diff --git "a/data/pcm/train.tsv" "b/data/pcm/train.tsv" new file mode 100644--- /dev/null +++ "b/data/pcm/train.tsv" @@ -0,0 +1,1061 @@ +category headline text url +sports Maduka Okoye: How Super Eagles goalkeeper become centre of attention for Nigerians """I no fit wait to see Maduka Okoye on top my screen today,"" dis na comment wey one of di female fans of di Super Eagles goalkeeper post ontop social media ahead of Nigeria game against Guinea Bissau. Di Super Eagles dey face Wild Dogs of Guinea Bissau for Match Day three of di 2021 Africa Cup of Nations for di Stade Roumdé Adjia in Garoua, Cameroon on Wednesday. Di Eagles dey top of Group D afta dia 1-0 win over Egypt on Tuesday and 3-1 win over Sudan last Saturday. If dem win, dem go be di first team to gada nine points from di group stage of di 2021 Afcon tournament. As football fans for Nigeria dey anticipate di performance of di Eagles for Wednesday match, di man wit di number one jersey, Maduka Okoye na di main focus for many female fans. One twitter user say dis na anoda day plus opportunity for Nigerian ladies to crush on Maduka Okoye. Di super eagles goalkeeper wey dey make im first appearance for major tournament dey totori millions of Nigerians, Africans, most especially women probably because of im looks and im football skills. E begin trend among female fans afta e post foto of imsef afta dia first game for Afcon tournament against di Pharaohs of Egypt wey dem win 1-0. E share di foto wit di caption 'Onto di next one' Di post don since gada almost eighty thousand likes, ova seven thousand retweets and thousands of comments most especially female fans. Check out some of di tins wey dem dey tok about di Super Eagles shot stopper. Meanwhile some Twitter users feel say Okoye dey attract a lot of distraction. ""I hope di guy fit stay focus and help win dis game"", na wetin one twitter user @ok_colzy tok. Dem born di 22-year-old goalkeeper for Düsseldorf, Germany to Nigerian father and a German mama. For 2019, im pledge im international future to Nigeria. Okoye get im first call up to play for Super Eagles wen former coach Gernot Rohr invite am to di Nigerian national team setup and hand Okoye im debut for one high profile friendly game against five-time world champions, Brazil for October 2019. For di game Nigeria gbab impressive 1-1 draw against di Selecao. Na for December 2021, Super Eagles Caretaker Coach Eguavoen shortlist am for 2021 Afcon Nations Cup as part of di 28-Man Nigeria Squad. Okoye career start for Germany wia im play for di German football club, Fortuna Düsseldorf II as dia regular goalkeeper between 2017, 2018-2019 season. For 2020, Maduka Okoye join Dutch professional football club, Sparta Rotterdam wia im don be dia number one. Later for 2021, im agree to join Premier League club Watford on five-and-a-half year deal for undisclosed fee. Okoye join Watford on 1 January 2022. Di deal see dem loan Okoye back to Sparta Rotterdam until di end of di 2021/22 campaign." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60056677 +entertainment Grammys 2020: Burna Boy, Angelique and oda tins wey pipo dey watch out for dis night "Di 62nd annual Grammy Awards go happun for Los Angeles on Sunday night, January 26. Dem dey call am ""music biggest night"", di ceremony na like di ""music longest day"" - wit different festivities wey dey start wit lunchtime for LA and e dey enta night time. Dem dey advise make pesin wear shoe wey go dey comfortable. Pop star Lizzo dey lead di nominations for dis year, with eight awards, including album and song of di year. Billie Eilish and Lil Nas X dey close to am with six nominations for each of dem. All dem three dey represent di new pipo wey dey lead di way for pop music and pipo wey no dey follow old ways wey dem dey use do things But, as Snoop Dogg sabi wella nominations no mean say you go win, im don go house 17 times wey im no collect trophy afta dem nominate. We no go fit predict pipo wey go win di award sake of dis reason but dis na some of di seven moments wey you go watch out for today. E no dey like shock to Nigerians wen dem nominate di Nigeria Afrobreat sensation Burna Boy among di nominees wey dey di 84 categories of di award wey be di biggest music award for di world. Di African Giant album of Burna wey im real name na Damini Ebunoluwa Ogulu, dey for di Best World Music Album category of di award wey be number 54 category. Angelique Kidjo from Benin Republic na anoda pesin wey also dey dis same award category wit Burna Boy. Oda pipo wey Burna Boy go battle di trophy wit for di category na Altin Gün, Bokanté & Metropole Orkest and Nathalie Joachim With Spektral Quartet. Dis na di first time wey dem go nominate Burna Boy for Grammy awards. Ten days before di Grammys, di Recording Academy drop bombshell say dem dey suspend dia chief executive Deborah Dugan with immediate effect. Dugan respond as she file discrimination complaint wia she suggest say di voting process for di Grammys get mago-mago inside. Some of her claims dey confam wetin evribodi dey suspect say e dey happun say dem dey treat pipo wey perform dat night beta pass oda pipo. Dungan still confam am say dem dey represent di artists to sit on di ""secret committees"" wey dey decide who dem go shortlist and dem go chook demselves for di list. But anyone go dey bold enough to acknowledge di claim - or refuse to collect di trophy - for di ceremony sake of dis mago-mago wey dem claim? Lana Del Rey na one of di contender for album of di year - but her record wey get swear-swear title go cause headache for di organisers dem. How dem go call am on top television and wetin dem go write for di trophy if she win? If you believe am or not, Harry Potter don already collect two Grammys - for best audiobook category - and JK Rowling boy wizard fit double di tally dis year. Dem nominate Imogen Heap song for Harry Potter and di Cursed Child for best musical theatre album category; while new recording of Hedwig Theme, wey appear for all di eight Potter films, collect nomination for best instrumental arrangement. Meanwhile, dem nominate Michelle Obama for spoken word category for di audiobook of her memoir, Becoming. Rapper Nipsey Hussle bin die last year afta dem shoot am for front of im clothing store for Los Angeles, US. Di 33-year-old dey do pass music, im be community activist, wey comit himsef to dey rebuild im neighbourhood. Afta e die, di Los Angeles Police Department hail am as a ""peacemaker"". He neva win Grammy wen im dey alive but organisers go recognise im legacy with star packed tribute wey go feature DJ Khaled, John Legend, Meek Mill, and gospel singer Kirk Franklin." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51254394 +entertainment Ayo Makun: AY Comedian and wife Mabel born dia second pikin afta 13 years "Nigeria comedian and feem maker, Richard Ayodeji Makun, wey pipo sabi as AY Comedian and im wife, Mabel don born dia second pikin. Di comedian na im announce di tori for social media say dem born 13 years afta dia first child Michelle. E reveal dis for video say di pikin na girl pikin. E tok say, ""Ayomide, thank you say you make Mabel and I, mama and papa again. Thank you say you make Michelle to be big sister."" AY and im wife bin marry for 2008 and get one pikin wey be 12 years, Michelle Makun. AY Makun na comedian wey blow for di industry wit di release of im stand-up comedy show wey im call AY Live wey start for 2010. AY also get TV drama series like AY's Crib and The AY Show. Howeva no be until 2015 e start to dey produce im own feem with 30 Days in Atlanta. Oda feems wey e don produce include 10 Days in Sun City, A Trip to Jamaica and Merry Men. E don follow plenti celebs work including Ramsey Nouah, Funke Akindele, Jim Iyke and international stars like Vivica Fox." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60040565 +sports Footballer wey bite im opponent penis for match chop five years suspension One player chop five years suspension for France sake of say im bite im opponent penis for fight wey happun afta dia match. Di incident happun for France for November 17 for di second division match between Terville and Soetrich. According to one local news website for Lorraine, kasala burst wen one of di players from each of di team begin fight demself, another Terville player come join, tori be say im try to separate dem. Na so di Soetrich player respond come bite im penis. Tori be say di victim need 10 stitches and e gatz take four days off work. 'Di incident happun afta dia match for di stadium car park. Di fight start small before e worse,' na wetin Emmanuel Saling of di Mosellan football district tok, 'im blame di two sides'. Na wetin im add put. Saling say because di 'case dey quite original', di disciplinary committee call expert witness before dem decide to suspend di Soetrich player for five years. While di injured Terville player chop six months suspension. Di match end for 1-1 draw wey for be Terville first point of di season but dem punish dem with two penalty points and fine dem 200 euros sake of say dem no meet dia safety obligations as hosts and for lack of reaction from club officials when di fight start. https://www.bbc.com/pidgin/sport-51564945 +sports Breakdown of matchday six games for Champions League Twelve teams don qualify for di round of 16 for Champions League so far. E mean say four teams go book dia place for di last match for di group stage of di competition. We torchlight wetin dem need to go through and breakdown wia each team stand for dia groups. Di round of 16 draw go take place for di House of European Football for Nyon, Switzerland, on Monday November 7. *Bayern Benfica *Chelsea Club Brugge Dortmund Inter Liverpool *Man City Napoli Paris Saint-Germain Porto, Real Madrid *Group winners Teams wey fit go through to round of 16 on Matchday 6: Eintracht Frankfurt, Leipzig, Marseille, AC Milan, Salzburg, Shakhtar, Sporting CP, Tottenham Teams wey don confam third place position and di Uefa Europa League knockout round play-offs: Barcelona, Sevilla Teams wey no fit reach di round of 16 but fit finish third: Ajax, Atlético, Dinamo Zagreb, Juventus, Leverkusen, Maccabi Haifa, Rangers Teams wey don confam fourth place: Celtic, Copenhagen, Plzeň Tuesday  November 1 Group A: Liverpool vs Napoli, Rangers vs Ajax Group B: Porto vs Atlético, Leverkusen vs Club Brugge Group C: Bayern vs Inter, Plzeň vs Barcelona Group D: Sporting CP vs Frankfurt, Marseille vs Tottenham Wednesday  November 2 Group E: Chelsea vs Dinamo Zagreb, AC Milan vs Salzburg Group F: Real Madrid vs Celtic, Shakhtar vs Leipzig Group G: Man City vs Sevilla, Copenhagen vs Dortmund Group H: Juventus vs Paris, Maccabi Haifa vs Benfica Napoli don qualify for di round of 16. Dem go finish first if dem avoid defeat to Liverpool by four goals or more. Liverpool also don qualify for di round of 16. Dem go finish first if dem beat Napoli by four goals or more. Ajax no fit reach di round of 16. Dem go finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if dem avoid defeat by Rangers by five goals or more. Rangers no fit reach di round of 16. Dem go finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if dem beat Ajax by five goals or more. Club Brugge don qualify for di round of 16. Dem go finish first if dem win, if di two games end for draw, or if Porto lose. Porto don qualify to the round of 16. Dem fit finish first if dem win and Club Brugge no win, or if dem draw and Club Brugge lose. Atlético no fit qualify for di round of 16. Dem go finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if dem win, or if both games end for draw, or if Leverkusen lose. Leverkusen also no fit reach di round of 16. Dem go finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if dem win and Atlético no win, or if dem draw and Atlético lose. Bayern dey through to di round of 16 as group winners. Inter too don qualify, dem finish second. Barcelona go finish third and compete for di UEFA Europa League knockout round play-offs. Plzeň finish fourth. Tottenham go qualify for di round of 16 if dem avoid defeat. Dem go finish first if dem win, or if both games end for draw. Spurs no fit finish fourth. Sporting go also qualify for di round of 16 if dem avoid defeat. Dem also fit finish first if dem win and Tottenham no win. Sporting go finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if dem and Marseille lose. Frankfurt fit reach di round of 16 if dem win. Dem go finish first if dem win and Spurs no win. Frankfurt go finish third if both games end for draw, or if dem and Marseille lose. Marseille go also fit through to di round of 16 if dem win. Dem go finish first if dem win and di oda game end for draw. Dem go finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if they draw and Sporting lose. Chelsea don qualify for di round of 16 as group winners. Milan go also qualify for di round of 16 if dem avoid defeat. Milan no fit finish fourth. Salzburg too fit qualify for di round of 16 if dem win. Dem go finish fourth if they lose and Dinamo win. Dinamo no fit reach di round of 16. Dem fit finish third and reach di Europa League knockout round play-offs if dem win and Salzburg lose. Real Madrid don qualify for di round of 16. Madrid go finish as group winners if dem win, or if Leipzig no win. Leipzig go also qualify for di round of 16 if dem avoid defeat. Dem go finish first if dem win and Madrid no win. Shakhtar too fit qualify for di round of 16 if dem win. Celtic go finish fourth. Man City don qualify for di round of 16 as group winners. Dortmund too don qualify afta dem finish second. Sevilla go finish third and compete for Uefa Europa League knockout round play-offs. Copenhagen go finish fourth. Paris and Benfica don qualify for di round of 16. Paris currently dey top sake of dia overall goal difference (+8 to +4) as dem plaw 1-1 wen both of dem bin meet. Juventus and Maccabi Haifa no fit reach di round of 16. Juventus currently dey third. Dia overall goal difference na (-3 to -9) both teams win dia direct home games by two-goal margin. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyxr1r6154lo +sports Ghana vs Nigeria play off: Super Eagles squad arrive Kumasi to clash Black Stars - Fotos "Super Eagles of Nigeria arrive Kumasi for de first leg of de 2022 FIFA World Qualifier play offs against Ghana on Friday. De first leg of de playoff go happun for de Baba Yara Sports Stadium inside Kumasi. On Wednesday de Super Eagles confam de squad wey dey play na: Goalkeepers: Francis Uzoho (AC Omonia, Cyprus); Daniel Akpeyi (Kaizer Chiefs, South Africa) Defenders:Oluwasemilogo Ajayi (West Bromwich Albion, England); Kenneth Omeruo (CD Leganes, Spain); odas include; Leon Balogun (Glasgow Rangers, Scotland); William Ekong (Watford FC, England); Olaoluwa Aina (Torino FC, Italy); Calvin Bassey (Glasgow Rangers, Scotland); Abdullahi Shehu (AC Omonia, Cyprus); Zaidu Sanusi (FC Porto, Portugal) Ghana Football Association Prez, Kurt Okraku lead di Nigeria Football Federation Prez, Amaju Pinnick together wit coach, players den technical team to dia hotel. De last time dis two kontris meet, na for 2011 but games between de two go way back as 1950. Ghana and Nigeria don meet 56 times across all competitions. De Black Stars don win 25 while de Super Eagles don win 12 and de oda 19 games end for draw. Playing Ghana away from home never really favour Nigeria as dem don lose 16 times weneva dia West African rival host dem. Six end for draw. Na only one time Nigeria win out of de 23 times wey Ghana don host. Ahead of de World Cup qualifier match between Ghana and Nigeria, Super Eagles Head Coach, Augustine Eguavoen say de team no go make di same mistakes wey dem make for AFCON 2021 wey Cameroon host. E talk BBC News Pidgin dis one afta di senior football team do press conference for Abuja on 23 March. ""E for beta make we lose one match for de group stage, den win de cup dan to win all come lose di most important match. ""We don learn from all our mistakes and e no go happun again, dis match dey important and na two-legged affair. ""We go try get sometin for dia (Kumasi) come finish am for here"" Eguavoen add say all de players dey kamkpe and ginger full dia bodi to play di match to qualify. Di return leg go happun for Abuja next Tuesday." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60862654 +entertainment BBNaija S6: Queen fight Whitemoney sake of Jackie B for Big Brother Naija 'Shine Ya Eyes' Di tension between Big Brother Naija housemates Queen and Whitemoney reach anoda level on Friday afta dia gbos-gbos sake of dia relationship. Dis na how di whole mata take start. As two of dem dey Kitchen, Whitemoney go meet Queen for dem to tok but she turn am down. Na dia im tell her say im go start to avoid her completely if she continue wit her attitude. Dat tok pepper Queen for body wey make her to accuse Whitemoney say: Im no dey straightforward wit her and she also accuse am say im dey carry her mata tell oda housemates. Tori be say on Wednesday Whitemoney and Queen bin discuss about im affection for Jackie B and Queen attitude. For dat conversation, Whitemoney bin tok about why im no enta Jackie B mata when Michael bin dey around. According to am na because of wetin im call di bro code, before im reveal to her say im dey catch feelings for Jackie B. Queen bin waka leave am but come back later wia dey two of dem sit down tok about dia wahala. Still ontop dia mata today Queen no bin happy with Whitemoney because he im share dia Wednesday conversation to oda Housemates. She also say she bin no dey comfortable wit di way Whitemoney dey get close to Jackie B since im be her friend. Cross later chook mouth for di mata and ask Queen some questions. Him ask her if Jackie B attraction to Whitemoney na problem for her. She say no but add say she go find am hard to dey free wit him if im end up in a relationship wit her. She claim say di reason why she come dey close to Whitemoney na because she see as pesin wey no get any love interest. Queen also accuse Jackie of snubbing her for di same reason, she tok how Jackie attitude completely change towards her afta Whitemoney reveal dia conversation to Jackie B and di oda Housemates. Jackie and Queen later sitdon to settle dia mata as she explain her own side of di story. Jackie B explain say di reason why she withdraw a bit from Queen na because she see say she ( Queen) bin dey moody and she bin no want ross any boundaries. Ontop Whitemoney mata she tell Queen say im bin don share im feelings before Michael come di House So make Queen no fear say she go lose Whitemoney. Queen also explain her side of di story. According to her she say she no dey aware say Whitemoney bin don express im affection to Jackie B before she come inside di house. She say she bin think say Whitemoney just start to expressing im affections afta Michael chop eviction. Something wey she say pain her. Aft her conversation wit Jackie B, Queen go meet Whitemoney for di dressing area and apologise to am for misunderstanding him and Jackie B relationship. On im part Whitemoney claim say since Michael and him from di same ethnic background, him no dey goafta im woman just because Michael don comot for di House. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58519835 +politics Non- Career Ambassador: Nigeria President Buhari do appoint 41 non-career ambassadors - See wetin you need to know about dem Nigeria President Muhammadu Buhari approve di renewal of di appointments of 12 non-career ambassadors and promise say ojoro no go dey for di representation. Dis promise from di president na sake of di recent complain afta di announcement of 41 non-career ambassadors wey say some states no get representative. Di president promise Nigerians say dem go carry everybody along for all matters of governance, according to one statement from di presidential palace Aso Rock. Now pipo don dey shine torch dey look di list to know who be dis 12 non-career ambassadors wey president Buhari approve dia re-appointment. Dr. (Mrs.) Uzoma Emenike wey come from Abia state, Nigeria don be di Ambassador of di Federal Republic of Nigeria to di Republic of Ireland before President Buhari renew her appointment on Thursday. According to di Nigeria Embassy Dublin website, she get two Bachelor degrees, two Master degrees, and one Doctorate Degree. Dr. Emenike wey be 55 years old, get B.Sc Sociology and Anthropology from University of Maiduguri and LL.B from University of Reading, U.K. She also get Master degree for International Law and Diplomacy from University of Lagos, Nigeria and anoda Master for International Management from University of Reading, U.K. Ambassador Emenike dey married to Chief Ikechi Emenike and dem born four children. Amb. Yusuf Maitama Tuggar wey come from Bauchi state, Nigeria na di Ambassador of Nigeria to Germany since 2017 before im reappointment. Dem born am for 1967 and e be former member of Nigeria house of representative from 2007 to 20011 wey e represent Gamawa Federal Constituency and also don contest twice for Governor of Bauchi State. Oga Tuggar get bachelor degree of Arts International relations from United state international University, San Diego, plus master degree from University of Cambridge. Oga Muhammad Madugu wey also come from Bauchi state, Nigeria na di ambassador of Nigeria to Switzerland before di renewal of im appointment. Dem born am for 1957 and e start im im career with Darazo local government area on di 1st of July 1997 as Community Development Supervisor. From Feb 2008- Oct 2009, e be permanent secretary for di civil service of Bauchi state and retire for dat office afta 33 years of service . Oga Madugu attend different seminars and workshop on management/Administration, planning, uilding and financial control. Baba Ahmad Jidda wey come from Borno state na Nigeria Ambassador to China. E don first serve as Secretary to Borno State Government (SSG) during di days of former Governor, Ali Modu Sheriff and then during di first tenure of Governor Kashim Shettima. E get B.Sc. Political Science from Ahmadu Bello University, Zaria and also attend University of Manchester, UK wey e for get M.A Development Economics plus Post Graduates Advanced Diploma in Development Administration. Oga Jidda don first be di Ambassador of Nigeria to Burkina Faso and also don contest for governorship election inside Borno state. Oga Uyigue Oghogho wey come from Edo state na High Commissioner of Nigeria to Mauritius. E start im career as supervisor for VESA FOOD AGENCIES LIMITED for 1986 before e come be honourable me=mber of di Edo tate House of Assembly and later RT Hon speaker Edo state House of Assembly from 2011 to 2015. Dr Eniola Ajayi wey come from Ekiti state na Optometrist/Ocular Pathologist by profession and na she be di current Nigeria Ambassador to Hungary. She start her career as with clinical duties inside di eye clinic of 445 Nigerian Air Forces Hospital but later leave dia for 1997 to start her private practice. Dem appoint her commissioner of Education , Science and Technology for Ekiti State from 2010 to 2013 and commissioner for environment from 2013 to 2014. Madam Deborah Iliya wey come from Kaduna state, na Nigerian Ambassador to Congo. She son attend plenti training wey involve cost and financial management, conflict management and resolutions, administrative management and efficiency, negotiation and leadership skill plus odas. Amb. Iliya don contest for primary election for senate inside Kaduna Southern Senatorial District for 2007 and 20015. She also don contest for General election for Senate, Southern Kaduna senatorial district and carry second for 2011. Oga Mohammed Rimi wey come from Katsina state, na di Nigerian Ambassador to di United Arab Emirates and e start im career with di Kaduna state Civil Service for 1977 as Economic planning Officer for di states Ministry of Economic Planning. E don attend plenti national and international course and seminars. Prof Tijjani Muhammad-Bande wey come from Kebbi state, na ogbonge scholar and diplomat wey be Permanent Representative of Nigeria to di United Nations and for June 4 2019, di United Nations General Assembly elect oga Tijjani as President of dia 74th session. Oga Tijjani get B.Sc for Political Science from Ahmadu Bello University, Nigeria in 1979, MA Political Science from Boston University, USA for 1981 and Ph.D Political Science from University of Toronto, Canada for 1987. Madam Modupe Irele wey ome from Lagos state, na Nigeria Ambassador to France. She start her career as teacher for di Teacher International School, Ibadan and she don also hold plenti oda position for differnet organizations and associations wey include di position of translator. She get Bachelor degree in English with small understanding of French from University of Ibadan, then continue with her masters for di same school. Plus second masters in education from University College Dublin and doctorate from Penn State University. Oga Adeyinka Asekun wey come from Ogun state, na business management professional wey be di Nigerian High Commissioner to Canada. E be graduate of University of Wisconsin, wey e for get Bachelor of Business Administration, focusing on Marketing. E also get MBA from California State University. E also sabi well-well for di banking industry and don work for International Merchant Bank, United Bank of Africa(UBA), and Oceanic Bank Plc (now Ecobank). Senator Goni Bura wey come from Yobe state, na member of di 4th senate from 1999 to 2003. E chaired di denate committee on Poverty Alleviation and na also member of different standing committee of di senate. E work as civil servant with Gedam Local Government Area from 1980 to 1987 and become chairmo of di local government from 1988-1989, then Deputy Governor of Yobe State from 1992 to 1993, Commissioner of works for Yobe state from 1992- 1993, senate elect for 1998 and senator for 1999-2003. https://www.bbc.com/pidgin/53275542 +entertainment Big Brother Naija 2021 housemates: Africa Magic reveal BBNaija Shine Ya Eye housemates "Di 2021 edition of di biggest reality TV show for Nigeria, Big Brother Nigeria don officially start. According to di show host Ebuka Obi-Uchendu di show go last for 10 weeks. Dis year, di title of di show na 'Shine Ya Eye' and for di first night, na only di boys dem reveal. Dem go reveal di girls for di Sunday part of di show. Dis season get two launch shows. Di first launch happun on Saturday 24 July, di second go be on Sunday 25 July. Di launch show go start by 7pm West African time. BBNaija na di biggest reality show for Africa, ova 49 kontries for di continent tune in to watch di season launch wey start by 7pm West African time, according to di show organizers. Boma Im be 34-years-old mixologist wey also don do some modelling and be former footballer. Raised by im single mother and grandmother, Boma bin don marry before. Boma suffer injury during football try-outs, im dey determined to ""never, ever, give up"" and hold onto im faith. Okusaga Dis 28-years-old engineer come from Lagos State. Okusaga aka Saga say im go ""bring vibe to di house"". Im say di lowest point for e life na wen im hear say e mama - wey im describe as e best friend - don die. Yousef Dis bi-racial Nigerian be teacher come from Jos, Plateau State and plan to bring lots of entertainment for di show. Im sey e go like make pipo dey call am Yousef. Pere Drama and gbas-gbos, na one of di housemates wey Ebuka announce as housemate on di show. Pere say im be actor and plan to ""bring spontaneity to di audience on di show"". Im say e be businessman wey dey into import of shoes. Multitalented Whitemoney describe imself as open-minded ""jolly good fellow"" wey like to catch fun. Di 29-year-old Lagos based Whitemoney originally come from Enugu State. Niyi Dis former basketballer come from Oyo State and e don marry wit one pikin. Im also be businessman wey dey run fantasy game platform and event business for Cape Town, South Africa. Niyi dey 6'6'' in heigth and likely go be di tallest housemate on dis season edition of di show. Yerins Im be medical doctor wey say ""e like to eat even though e no dey show for im body"". E describe imsef as 'polymath' wey get undying love for many creative things. 29-years-old Jay Paul come from Calabar, Cross River state, e describe imsef as ""social butterfly"". Im be complete entertainer wey dey run tourism business. Jay Paul dey act, sing and dance as well. Im be 24-year-old model wey come from Akwa Ibom State. Emanuel na model wey dey into pageantry and be winner of Mr Africa. E dey single and say possibility dey say im go fit ""mingle"". Sammie Sammie na final-year student wey dey study Guidance & Counselling for Ahmadu Bello University, Zaria. Im come from Kaduna State and plan to enjoy imsef for di show. Cross 31-years old Ikechukwu love clubbing, dancing and girls wey also like to see ""women fight over am"". E dey into yoga and plan to bring drama ""Wey concern boys and girls fight"". Big Brother Nigeria 1 Katung Aduwak$100,000 Big Brother Naija 2 Efe Ejeba N25,000,000 Big Brother Naija 3 Miracle Igbokwe N45,000,000 Big Brother Naija 4 Mercy Eke N60,000,000 Big Brother Naija 5 Olamilekan Agbeleshe N85,000,000" https://www.bbc.com/pidgin/57946016 +entertainment BBNaija: Erica and Kidd 'ship' for Big Brother Naija show dey make fans heart cut - See di reason why Fans of Big Brother Naija dey react to Kiddwaya and Erica relationship afta she tell am say make dem continue as friends and nothing more inside di house. On Wednesday August 5, afta dia Wager rehearsals, Erica and Kiddwaya do two aside tok wia she tell am say she wan to focus on di game without any man distraction. She say she dey enjoy all dia cuddles and intimate moments wey dem dey share togeda but going forward she go like focus on her game and career. Afta she tok finish, Kiddwaya no fight or tok too much e just say ok and carry on with im normal activity for di house. E no reach complete 24 hours afta two of dem discuss about dia relationship mata say make dem just be friends, dem begin play love again. Kiddwaya and Erica hold each oda for chair for parlour, eat from di same plate and even kiss too join. Many fans enta social media to react to di couple relationship mata for inside di Big Brother Naija lockdown house. Dem use di #kiddrica to express how dia relationship dey go so far. Dis week, 16 housemates dey up for possible eviction on Sunday, na only di head of house Ozo and Deputy head of house Dorathy dey safe from eviction. Voting go end on Thursday August 6. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53685835 +entertainment Silhouette Challenge videos: Who be Paul Anka, di man behind di 'Put Your Head On My Shoulder' song? "Silhouette challenge don become viral sensation across all social media platforms for di world. E dey common for most social media challenge to be about songs or promotion for a particular song but Silhouette challenge dey different, as e bring a 1959 song back to life. Plenti pipo bin no dey familiar wit di 'Put your hands on my shoulder' song by Paul Anka until e become household music, No thanks to di popular Silhouette Challenge. Even though Paul Anka na di big brain behind di song, no be im be influencer of di Silhouette Challenge. For pipo wey dey wonder wetin be dis challenge Silhouette Challenge na about 1 minute tik-tok video wey users dey create as dem go pose sexy for door side or frame in a teasing manner before dem go later turn to black silhouette for red background mostly without clothes. Dis switch from normal background to Silhouette dey also follow di sequence of di song. At a point wia di lyrics of di song start from ""Put your hands on my shoulder"", di lighting of di video go change Put your hands on my shoulder na song by Canadian musician and song writer. Paul Anka Di song na love song wey tell di tori of pesin wey dey find of trust and commitment for relationship as di title dey imply. For inside di song, e say ""Hold me in your arms, baby, Show me dat you love me too..."" Paul Anka write and record di song for 1959, at di height of im fame as a pop musician. For inside di song, Anka capture di tenderness of di 1950's teenage popular culture. Fast forward to 2021, e be like say di evergreen song still dey catch di tenderness of young pipo, as many don jump on di Silhouette challenge trend. Paul say im inspiration for di song bin come from fans, whom im dey always observe during im live performances. Canadian-American singer, songwriter and actor, Paul Anka na di brain behind di social media trend #SilhouetteChallenge background song. Dem born Paul Anka for July 30, 1941, for Ottawa, Ontario, Canada to Camelia and Andrew Emile Anka Sr. both of Lebanese descent. Paul Anka record im first single, ""I Confess"", at di age of 14 but e become popular wen he release im single, Diana. Im contribution to di industry dey so big sotee, im join Michael Jackson to write di song ""I Never Heard, Love Never Felt So Good"" in 1983. Paul Anka don also feature for plenti feem. He start im acting career wit di movie, ""The Longest Day"". He don also produce songs for many feems. Paul Anka song ""Put Your Head On My Shoulder"" don since get over 62 million views on YouTube." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55868991 +health Hydroxychloroquine side effects: All you need to know about di drug Trump say im dey take to prevent coronavirus "US President Donald Trump say im dey take anti-malarial drug hydroxychloroquine as preventive measure against Covid-19, although sabi pipo don warn about di side effects. But sabi pipo still dey study if hydroxychloroquine (and one drug wey resemble am wey dem dey call chloroquine) dey effective against coronavirus. Di World Health Organization say dem dey concerned by reports of pipo wey dey do self-medication and dey cause serious harm to dia body. One former top US health official bin don tok about di safety concern before. Dr Rick Bright,wey dem remove from im post for April bin dey lead di goment vaccine development efforts, e say President Trump focus on these drugs dey ""distract dozens of federal scientists"". And US Food and Drugs Administration, wey bin give approval to use them for specific occasion only, don also warn about di possible side effects. President Trump bin don tok about di potential use of hydroxychloroquine during im White House briefings. For press conference for April, im say: ""Wetin you get to lose? Take am."" And Brazil President Jair Bolsonaro claim for inside one video say hydroxychloroquine dey work everywhere"", although Facebook don remove dat part ontop say im break dia misinformation guidelines rule. Sake of all di publicity wey di drug get as possible treatment, di demand for dem don increase well-well for di world. Afta Presido Trump chook mouth for di drug mata for late March, prescription for both chloroquine and hydroxychloroquine increase for US. Tori be say tablets wey get chloroquine dem dey use am for di treatment of malaria to reduce fever and inflammation, and di hope na say dem fit also slow di virus wey di cause Covid-19. Trials dey happun for different kontries on using di drugs to prevent di illness. As part of these studies, frontline workers wey dey highly exposed to di virus dey take am as preventive measure. Oda studies dey chook eye weda e fit help patients wey already get Covid-19. For US, various trials dey go on for combination of drugs including chloroquine, hydroxychloroquine and one antibiotic wey dem dey call azithromycin, for treating Covid-19 patients. But di evidence wey dey no dey too much for now from current trials as to how effective e dey to treat patients with Covid-19. Risks of serious side effects, including renal and liver damage also dey. For late March, di US Food and Drugs Administration (FDA) bin grant ""emergency use"" for di use of dis drugs to treat small number of Covid-19 cases for hospital. E no mean say di FDA say e go work. But e mean say for some kain circumstances, hospitals fit request and use di medicines from goment stockpiles for Covid-19 treatment. But on 24 April, FDA also warn about di dangers of using di substances because of reports of heart rhythm problems for patients. US goment say one German-based pharmaceutical company donate 30 million doses of hydroxychloroquine give dem. Oda kontries dey also use di anti-malarial drugs to some extent. France don authorise dia doctors to prescribe dem for patients with Covid-19, but di kontri medical watchdog don warn about di side effects." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52730407 +entertainment Ned Nwoko: Jaruma reply Regina Daniels husband post about her marriage 'despite say she dey sell kayanmata' "Popular sex therapist and aphrodisiac seller Hauwa Saidu wey dey popular as Jaruma don condemn oga Ned Nwoko comment say her husband don leave despite say she dey sell kayanmata (sex enhancer). For inside one video wey Jaruma post for her social media handle, she say she no happy about how 74-year-old Ned Nwoko wey pipo respect fit come social media dey tok bad tins about im wife wey im marry for many years. Oga Ned bin question why di businesswoman marriage no work for one Instagram post wey im bin make on Wednesday. Ned Nwoko bin dey respond to reports about how im divorce e Moroccan wife, Laila Charani. ""As for Jaruma wey claim say her kayanmata dey work on Ned Nwoko and dat na why im wife Laila leave, dat kind tok-tok dey baseless and laughable. ""To clear di record, make we ask... Jaruma bin marry young man, how come di marriage wey produce one pikin end barely one year? How come di kayanmata no work on di husband. Gullible fans no know say di ex-husband leave her despite di kayanmata effects on im. What a joke,"" e tok. Jaruma say: ""oga Ned tok say her husband leave am two years ago, but di man never say any bad tin about her and she never say any bad tin about di man too."" She add say ""pipo bin don move on afta im wife Regina Daniels deny say she don ever use her kayanmata but oga Ned still come back three weeks later to tok worst tins about her. ""Make oga Ned try think am say if her kayanmata no dey work 21 years old girl no fit able to control im and im media team to type five pages tok tok about Laila im ex wife and Jaruma,"" she tok. For di 16 minutes plus video, Jaruma say she don make more money as show one plenty paper wey she call bank statement of di money wey she don make since Regina bin post disclaimer say she no dey use Jaruma product. She urge oga Ned to confam from im bank friends weda na true. She say oga Ned no try at all for dat kind tin wey im do but she say she dey happy say she get more followers and customers afta dem release bad post about her. Hauwa Saidu Mohammed wey pipo sabi as Jaruma na Nigerian sex therapist and entrepreneur. Dem born her for October 26, 1993. She come from Gombe state and many reason her as di most successful and highest-paid sex therapist for Nigeria. Jaruma bin start her entrepreneurship career for 2010 as she engage for some businesses but na for 2016 she enta limelight afta she do one video to educate Nigerians about di therapeutic advantages of Azanza Garckeana plant (Silky Kola). She begin sell sex enhancers products, kayamata wey she claim say dey save women from experiencing failed marriages because dem no fit meet wit di sexual demands of dia partners. Although some pipo don accuse her say dey add juju to her products to enable her clients fit trap men wey go dey do dia bidding once dem meet." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59592321 +sports Arsenal vs Liverpool: Aubameyang lead Gunners to Community Shield victory English FA Cup winners, Arsenal don win dis year Community Shield after dem beat Liverpool 5-4 on penalty. Aubameyang bin open di scoring during normal time before Takuma Minamino equalise for Liverpool to send di tie to penarity shoot-out. Di Gabon international na him score di winning penalty to give Arsenal coach Mikel Arteta im second trophy wit di club after only 6 months wey im don dey in charge of di Gunners. Teenage Liverpool striker Rhian Brewster na im miss di only penalty for Liverpool after im shot hit di crossbar. Dis na di second straight season wey Liverpool go lose di Community Shield afta dem lose to Manchester City last year on penalties. Traditionally, di Community Shield na im dey welcome di start of di new English season. Di 2020/2021 Premier League season go start on 12 September, 2020. https://www.bbc.com/pidgin/sport-53961731 +entertainment Gorilla glue girl update: Ghanaian-born surgeon Dr Micheal Obeng profile - Tessica Brown 'gorilla glue for hair' doctor life story Dr Micheal Obeng, na di Ghanaian-American wey help Tessica Brown remove di gorilla glue from her hair. Tessica Brown go viral wen she post Tiktok video onto say see nwee! for almost one month afta she try to wash di gorilla glue comot from her hair. She reveal say she dey carry di same hair style for about one month, no be say she like am but because she change her usual Got2b Glued spray wit di industrial-strength glue wen her glue spray finish wey be bad idea. She try eviritin wey she sabi to wash am comot e no work until Dr Michael Obeng reach out to her and promise to treat her free of charge. Dr Obeng do di surgery for her hair to comot di gorilla glue. Tori be say di surgery take up to four hours and if to say she pay wit her money e for cost her about $12,500. So who be dis Dr Micheal Obeng wey save di gorila glue girl? Dis na eviritin you need to know about dis Ghanaian-American doctor. Place of Bate: Dem born Dr Obeng for di West African kontri of Ghana. Professional skill: Obeng na certified plastic surgeon wey specialize in cosmetic/aesthetic plastic surgery and reconstructive surgery. Location: Im dey live for Beverly Hills, California for United states of America. Education: Na Harvard im do im training. For 2011 and 2014 Consumer Research Council of America name am among di top plastic surgeon. Job: Currently e be staff for Cedars Sinai Hospital, and di former Chief of Plastic Surgery for St. Elizabeth Health Center. Accolades: Dr. Obeng get plenty experience ontop plastic surgery mata. Na him be di founder of Miko Med Spa, wey dey for Beverly Hills. Him clients dem include royalty and celebrities, but also includes some of di world most unfortunate patients. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56030201 +entertainment Rema Unilag: Teni, Kim Kardashian, Kanayo O. Kanayo and oda celebrities wey don go school despite say dem popular Ogbonge Nigerian music artiste, Rema wey im real name na Divine Ikubor, reveal say im don get admission to di University of Lagos to study inside di Creative Arts department. E tok dis one for Twitter say na im mama kolobi am make im go school even as im don blow for di music career. Howeva, di Soundgasm artiste don declare say im go try to drop album before im become fresher for Unilag. Rema no be di only famous pesin wey don carry celebrity status enta school before. E fit learn work from di life of oda public figures like: For 2018, Teni Apata wey dey popularly known as Teni di entertainer bin graduate from di University of Georgia. For her time for di school, Teni don already sing hits like Fajin and Askamaya, dat same year before she graduate she gbab di Rookie of the Year for di Headies awards. For May 2018, Yoruba actor, Odunlade Adekola wey dey popularly know as di king of memes bin graduate from di University of Lagos with degree for Business Administration. By dat time oga Odunlade don already don de di Nigerian movie industry dey act feem for ova 10 years. Nigerian music artiste bin enta di Nigerian Institute of Journalism, wia im bin study and graduate with im Higher National Diploma for April 2018. Tori be say e even gbab di best student for Editorial Writing. By dat time Korede Bello don blow for Mavins records as well as im ogbonga hit God Win among odas. Kanayo O. Kanayo wey dey popular for Nigeria on top di money ritual movie roles wey im don act, start im tori of schooling for 2015, wen im enta di University of Abuja to get im Law Degree. Di tori come blow for September 2020 wen im get im call to bar to practise as lawyer at di age of 58. Anoda pesin wey shock pipo wen she graduate na American rapper Megan Thee Stallion. Di Savage rapper bin graduate with degree in health administration for December 2021 from di Texas Southern University. Although popular reality star Kim Kardashian no return back to school in di real sense of di word, di mother of four don find anoda way to get her law degree., For 2021, Kim Kardashian pass her mini law exam afta she don try three separate times. Dis dey come as she say she wan become lawyer for 2019 afta she follow fight for di release of Alice Johnson wey bin gbab life in prison for drug trafficking for 1997. She use anoda method to take study law, according to her, she bin dey intern for law firm for her studies instead of to go law school direct. Dis list wey we put togeda no mean say oda celebs no dey wey don also go school. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59920071 +politics Afrobarometer report reveal 42% of Ghanaians say dem no go vote ahead of 2020 elections "Latest Afrobarometer report wey Center for Democratic Development (CDD) put together dey show say 4 out of 10 Ghanaians say dem no go vote if elections happen 'morrow.' Dis dey represent 42 percent of Ghanaians who no want participate for election inside if Ghana for vote morrow. After dem ask which party candidate dem go vote for if election happen the next day, 12 percent say be undecided about who dem go vote for, wey 19 percent no answer de question. CDD say dem interview total of 2,400 adult Ghanaians between 16th September and 3rd October 2019 for dis survey. Dem point out say from de data dem collect, majority of those dem interview declare dema support for ruling New Patriotic Party (NPP) over de opposition National Democratic Congress (NDC). But one key thing be say NPP lose some 15 points lead wey dem get over de NDC from de last survey wey happen 2017. ""If we compared to 2017, de percentage of respondents who say dem go vote NPP reduce by 15 percentage points from 49% to 34%. Meanwhile, de percentage wey say dem go vote NDC remain de same around 22 percent."" According to CDD, de latest Afrobarometer report record de highest percentage of people wey no wan vote for election inside since 2008 wey dem start dis survey." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50725184 +sports Nigeria Vs Sierra Leone: Super Eagles Ahmed Musa don apologise for dia draw game "Captain of Nigeria Super Eagles Ahmed Musa don say sorry on behalf of di team for di kain game wey dem play wit Sierra Leone on Friday. Sierra Leone come from four goals down to play 4-4 draw wit Nigeria for dia group L, African cup of Nations qualifying match wey happun for Samuel Ogbemudia stadium for Benin City. Musa do video wey im post for social media ontop di mata - di team forward say dem sorry for di game and promise say dem go win wen next dem play Sierra Leone. ""We know say we make very big mistake but nothing wey we fit do. No so football be; sometime we win, sometime we lose"". ""We go try our best and we sure say we go qualify for AFCON. We go make am up,"" e follow tok. Nigeria wey take di lead through Alex Iwobi inside five minutes bin control di game for first half wit goals from Victor Osimhen, Samuel Chukwueze and anoda from Iwobi to go 4-0 inside 31 minute." https://www.bbc.com/pidgin/sport-54942881 +entertainment Mercy Aigbe: Movie Producer Kazim Adeoti open up about im marriage to di nollywood actress "Chairman of Ibaka TV, Kazim Adeoti and husband to popular Nollywood actress, Mercy Aigbe don open about dia relationship and marriage afta tori of dia relationship bin go viral a while back. Oga Adeoti inside one interview e gada do wit im new wife clear di air about some controversy wey surround dia relationship. First na di mata of separation from im first wife because e wan marry di actress. Di movie maker for di interview clear am say im no separate from im first wife as dem still dey together. E explain say although some issues bin dey but dem don settle am and everything dey okay now and under control. Oga Adeoti add join say as Muslim, im get right to marry more than one wife, so now im dey married to two wives and im dey comfortable wit im decision. E also clear di rumour wey bin go viral at di time say im and Mercy ex-husband, Lanre Gentry na friends. Di business mogul say dem no be friends. Oga Lanre Gentry bin share one foto of all of dem togeda wey make am look like say dem be family friends before di divorce but Adeoti say di foto wey go viral na foto wey dem take during im 40th birthday. E say im invite plenty Nollywood stars for im party and some of dem come wit dia partners and dem take foto wit am as per celebrant, na there di foto bin comot from. Mercy Aigbe also deny tori say im marry di movie marketer sake of im money. She say she dey very rich and comfortable even before she agree to marry Adeoti. ""I be ambassador, brand influencer, I dey do business and di biz dey thrive, I dey make good money and I dey bring something come di table."" She add. Di couple say dem don sabi each oda for more than 10 years but strictly on business level. Oga Adeoti say Mercy be im business partner as dem dey do movie togeda but wetin attract him to her na her transparency and openness. Wen she dey go through issues for her previous marriage, e bin dey part of dos wey advise her to dey calm and patient and remain for di marriage as things go work out. E say im even dey for America dat time and no too dey involved wen she leave her husband. But as time go back, dem see say dem like each oda, complement and find comfort in each oda company, dem tok. Mercy wey express her love for her new husband say she believe she don reach her final place in marriage. She also add say she dey reason to change to Muslim because di reception she dey get from Muslims dey overwhelming. Although her husband no mind as e believe say dem dey serve di same God. Di 49 year old movie maker hail from come from Oro, Kwara state. E go boarding school for im nursery and primary education. He get degree for Business Management from di University of Jos before e relocate go USA. Adeoti say im bin work as security man for a while, come go school to obtain mortgage licence. e practice for Minnesota for almost a decade before e relocate come Nigeria to start di business of movie productions. Di Yoruba filmmaker na movie marketer and founder of Adekaz Productions. E dey popular for Yoruba movie industry as e dey behind some of di biggest movies for di sector. E bin don marry and e get four children wit im wife Funsho. Mercy Aigbe na Nigerian actress, director and businesswoman. She dey popular for Nigerian Yoruba films. Dem born her for January 1, 1978 for Edo state southern Nigeria. She come from Benin City, di capital of Edo state. She get OND for financial studies from di Polytechnic of Ibadan. She come further her education and graduate wit degree for Theatre Arts for University of Lagos. Mercy Aigbe start her acting career wen she feature for some soap operas. Di popular TV drama series Papa Ajasco na one of am. She join Nollywood industry fully for 2016. She don act many feems and collect plenty ogbonge awards." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60620943 +sports Mauricio Pochettino no mind to look outside Premier League top six for im next job "Mauricio Pochettino dey reason to find im next managerial job outside di Premier League top six. Pochettino neva get any work since Tottenham sack am for November 2019. Dem link di 48 year old wit one deal wey join New Castle and Saudi Arabia. Maurico say im go take anytin as di clubs wey dey di top six fit change anytime. According to am, Tottenham and Arsenal no dey d top 6 today and e no good to look down on any club as all of dem dey try. He say e dey important to respect all clubs because dem dey spend money for di club, invest for di club and dey try new ways to put di club for di top 6., 8 ot top 4. Southampton dey three points and dem no dey relegation zone wen Pochettino join dem January 2013. Tottenham just finish sixth when e replace Tim Sherwood as manager 18 months later. In five-and-a-half years, he change Spurs and lead go Champions League final last season. He manage di enta four successive top four finishes for di first time for almost 50 years, although di chairman Daniel Levy sack am come replace am wit Jose Mourinho after im no win trophy and di club dey 14th position for Premier League. ""Football no be about budgets and money,"" he tok. Pochettino wish to go back di game don increase as e dey absent. He follow Levy tok last weekend as im 'gardening leave' an end, dis one mean say e fit accept other offers now. He wish im old club - and Mourinho well - and even meet wit im old north London rival, former Arsenal manager Unai Emery for coffee, where they reflect on dia experience of how dem chop sack for mid-season. But for di last two months, Pochettino dey im house for London, sake of Covid-19 lockdown, wey don affect football badly and mae di game lose plenty billions of pounds." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52785731 +entertainment Toyin Lawani: From Fashion businesswoman to mama and wife "Nigerian fashion entrepreneur Toyin Lawani tie di nuptial knot wit her boo photographer Segun Wealth for all black wedding inside Lagos. Di celebrity stylist bin marry on Saturday 12 June, 2021 for Lagos. According to im Instagram, Segun first show Toyin face as im take her picture for March 2020. Even sef for October last year, she bin post for her pikin, handle, Oluwatenola Jermaine Womandi, one caption wey Segun bin write about di situation for Nigeria. Celebrities pack demselves full for inside di business woman wedding wey include, Denrele, Mercy Aigbe, Iyabo Ojo among plenti odas. She dey popularly known as celebrity stylist, but mummy Tiannah reveal for her reality show for 2017 say she get ova 30 businesses she dey run wey she call ""Tiannah's Empire"". Dem born di serial businesswoman for March 1, 1982 for Ekiti state. Di 38-year old na mama of two children - 16 year old Tiannah and 6 year old Tenola wey tori be say she born for former boyfriend, 28 year old, Kesington Womandi, wey dey popularly known as Lord Triggs. She bin reveal say she marry her first pikin papa, when she be 19-years old. Di business woman also lose her papa, Olanrewaju Lawani for April dis year. She bin don reveal for interview say she start to dey run her business at di age of 16 wen she bin still dey for University of Lagos. Segun wealth or as im dey call imself, masked Artist na photographer wey don work on di more risque pictures wey Toyin Lawani don carry come outside. E dey also sing under the name DeeUnknown and release im first single for November 2020." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57458713 +politics No to midnight meeting for Jigawa No more midnight meeting for young boys and girls for one local goment wey dey Jigawa state, north west Nigeria. Authorities for Kirikasamma Local Goment area don ban meeting between man and woman for night and any pesin wey dem catch go chill for prison. Di local goment council authorities tok say dem dey do dis ban sake of all di plenti single women wey dey cari belle outside marriage for di local goment. Di leader of di local goment councillors Sa'idu Marma, during di signing of di law say, fornication and unwanted pregnancies among girls na one of di biggest wahala wey di local goment dey face and dat na why dem need di law. According to di law, any pesin wey dem catch dey meet for night with member of opposite sex go fit spend six months for prison or pay fine of fifty thousand Naira ($138.31). Di local goment informate officer, Sanusi Daro say, di council sign di bill afta di ten councillors bin all agree. No be only Kirikasamma local goment get dat kain law. For Gayawa town for Kano state, boyfriend and girlfriend no fit meet afta 9pm or else dem go arrest dem. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50958823 +health Andhra Pradesh: India 'mystery' sickness put hundreds of pipo for hospital "At least one person don die and 227 pipo dey admission for hospital sake of sickness wey authorities neva fit identify for India southern state of Andhra Pradesh. Di patients get many different kinds of symptoms from feeling like say dem wan vomit to becoming unconscious, doctors tok. Officials dey investigate wetin fit cause di sickness wey don spread throughout di town of Eluru for weekend. Dis one dey happun as India still dey battle wit coronavirus pandemic as di kontri wit di world second highest number of cases. Andhra Pradesh na one of di states wey dey worst affected, e dey number three position wit more dan 800,000 cases . But, e no be like say na Covid-19 make all dis pipo dey admission during di weekend. Di state health minister, Alla Kali Srinivas, say all di patients test negative to coronavirus. ""Di pipo wey fall sick, especially pikin dem, suddenly begin to vomit afta dem complain say dia eyes dey burn, some of dem faint or suffer convulsion,"" one medical official for Eluru Goment Hospital tell Di Indian Express newspaper. Oga Srinivas say di patients blood samples no show any evidence of virus infection. ""We rule out say no be water contamination or air pollution be di cause afta officials visit di areas wia pipo fall sick, "" im tok. ""Na one kain mysterious sickness and na only lab test go reveal wetin e be."" However opposition Telugu Desam Party don ask for enquiry into di mata as dem insist say na contamination cause di mysterious sickness. Dem don discharge seventy pipo, while 157 still dey hospital, officials tok. Di state chief minister, Jaganmohan Reddy, say dem don send special treatment team go Eluru to investigate di cause of di sickness. Oga Reddy suppose also visit di town to meet di patients and dia families." https://www.bbc.com/pidgin/world-55214019 +politics Trump impeachment: Senate go begin Trump impeachment trial next week "Donald Trump's impeachment trial ova im role for di deadly US Capitol riot go begin next in di Senate, dis na according to di Democrats. On Monday, di House of Representatives go deliver di impeachment charge to di senate , wey go trigger di trial process inside di 100-member chamber. Republicans don argue say make dem delay am as dem ask for more time to prepare. Oga Trump fly go Florida afta im term end on Wednesday and e no attend im successor Joe Biden's inauguration. Di House of Representatives last week bin accuse Oga Trump say e incite deadly riot for di US Capitol , which dey give way for a Senate trial. If dem find am guilty, dem fit bar am am from future office. Top Senate Democrat Chuck Schumer on Friday tok say di House go deliver di impeachment article on Monday. Unless Democrats wey don become di majority change di rules dis week, e go mean Oga Trump's trial go go begin on Tuesday. ''Di Senate go conduct a trial of di impeachment of Donald Trump. E go be a full trial. E go be a fair trial'' Senate Majority Leader Schumer tok dis for di floor of di Senate. Oga Trump's action before di 6 January riot dey di heart of di case. Di then president bin tell protesters wey dey near di White House make dem ''peacefully and patriotically'' make dem voice heard as dem dey prepare to march toward di US Capitol building. E also tell dem to ''fight like hell'' Short answer no, but dem go fit run President Donald Trump impeachment afta di inauguration of Joe Biden as di new president of di United States. Dis dey come afta US Republican Senate Leader Mitch McConnel bin tok for statement say ""on top di kain rules, procedures and Senate precedents wen e dey di mata of presidential impeachment trials, e no dey possible say we go get fair or serious trial wey fit finish before dem swear in the President elect Joe Biden next week."" And if Senate convict Trump, e fit be di end of im political dream to run for office for 2024. Some Republicans don point out say going on with di impeachment fit divide America even more and affect di work of Joe Biden to reunite di kontri. Even sef Joe Biden don ask weda Senate ft run part-time trial for Trump, so dem go fit focus on oda tins like confirmation for im cabinet and legislation. Although di impeachment no go fit hold wen im dey office (till next week) but afta wards two thirds of the Senate go need to vote in order to comot am. Currently both Republicans and Democrats get di same amount of seats for Senate so at least 17 republican senators go need to side with di democrats to make am happen. If dem convict am under the article of impeachment, e mean say dem go need to vote again to block am make e no run for anoda elected office again, sometin wey im bin dey plan for 2024. Na on Wednesday, Congress bin vote to impeach am for di the second time wen dem accuse am say na im use im mouth cause di kata-kata for Capitol Hall last week wey kill five pipo. Dis go make am di first president for American history wey don chop impeachment twice for one term." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55646739 +sports Maradona hand of god: Diego Maradona children and what to know about 'El Pibe de Oro', Argentina football icon wey die at di age of 60 "Football fans around di world dey mourn afta di death of ogbonge football star Diego Maradona wey die at di age of 60. Football stars, fans and pipo around di world don dey pay dia tributes even as for statement ontop social media, di Argentine Football Association express ""dia deepest sorrow for di death of our legend"", dem add say: ""You will always be in our hearts."" Tributes don come in from ogbonge former football players like Ivory Coast Didier Drogba, Nigerian Kanu Nwankwo, Cameroon Eto'o Fils, Liberia President George Weah and odas. Dem born Diego Armando Maradona to Roman Catholic family for 30 October 1960, 60 years ago for Buenos Aires shanty town. Im parents na Diego Maradona Senior and Dalma Salvadora Franco. He marry im long-time fiancée Claudia Villafañe on 7 November 1984 for Buenos Aires, and dem get two daughters, Dalma Nerea wey dem born 2 April 1987 and Gianinna Dinorah wey dem born 16 May 1989 and he become grandfather for 2009. Maradona and Villafañe divorce for 2004. He escape di poverty of im youth to become football superstar and some even dey reason say e great pass Brazil Pele. Madonna get short stature and e dey stocky. Im height na 5ft 5in, e no be your typical athlete. Dieggo Maradona na Argentine professional footballer and football manager. Many pipo see am as one of di greatest football players of all time, and by many di greatest ever. Di Argentine, wey score 259 goals inside 491 matches, pass im South American rival for one poll to determine di greatest player of di 20th Century, before Fifa change di voting rules to honour both players. Maradona show great ability since e dey young age wen e lead Los Cebollitas youth team to a 136-game unbeaten streak and from dia go on to make im first international appearance wen e be just 16 years and 120 days. But im silky skills, agility, vision, ball control, dribbling and passing more dan compensate for im lack of pace and occasional weight problems. Im presence and leadership on top field get great effect on im team general performance, as opposition go dey monitor im movement. To add to im creative abilities, e also get eye for goal and im be free-kick specialist. E get correct talent. Dem give Maradona nickname ""El Pibe de Oro"" wey mean (Di Golden Boy), name wey follow am throughout im career. Maradona na di first player for football history to set world record transfer fee twice. First dem transfer am go Barcelona for den record fee of £5 million and second wen dem transfer am go Napoli for anoda record fee of £6.9 million. E play for Argentinos Junior, Boca Juniors, Barcelona, Napoli, Sevilla and Newell Old Boys during im club career. E lead im kontri to victory for di 1986 World Cup for Mexico and a place in di final four years later. Maradona play di best club football of im career for Italy, e get plenty supporters as e inspire di side to dia first league titles for 1987 and 1990 and di Uefa Cup in 1989. All no jolly for Maradona as dem link am to di Camorra crime syndicate, im begin take cocaine even become addict and e get paternity case. From the mid-1980s until 2004, Maradona dey addicted to cocaine. Afta losing 1-0 to Germany for di final of Italia 90, im testing positive for drugs di following year make am chop 15-month ban. E return to play for di 1994 World Cup for USA. Im mind no too dey di game afta dem discover say im don take substance ephedrine. Afta im third positive test three years later, e retire from football on im 37th birthday, but problems still continue for am. Dem suspend im jail sentence of two years and 10 months wey e suppose go sake of say im shoot at journalists with air rifle. Im cocaine habit and alcoholism lead to several health issues. E put on weight, wey reach 128kg (20 stone) at one point, and suffer a major heart attack for 2004, wey put am for intensive care. E get gastric-bypass surgery to help manage im obesity, and go Cuba wen im dey battle to overcome im drug addiction. Despite all dis, dem make Maradona manager of di Argentina national team for 2008 and e take di side to di World Cup quarter-finals two years later before im reign end with 4-0 defeat by Germany for di quarter-finals." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55077115 +entertainment Nazo Ekezie: Don Jazzy reply Nazo Ekezie, nollywood star wey dey shoot her shot "Nazo Ekezie, nollywood star dey shoot her shot for Don Jazzy, Nigerian singer and music producer. ""I no know if you remember say I meet you di oda day at imax lekki...... me I no dey slim... so I no go never ever stress you about loosing weight.... I like you like dis abeg make we go on a date"" Na di birthday message Don Jazzy as she call am 'my crush' Don Jazzy inside im response ask Ekezie to choose a date of her choice to go on di date together. Di Nigerian music producer also tell her im go dey be happy to go on di date with her. For im reply im Don Jazzy say: ""Kai, Oya let's set the date o. I will definitely love to. Thanks a lot""." https://www.bbc.com/pidgin/world-55097656 +business Why Nigeria goment sue Facebook, Instagram and WhatsApp for N30B "Nigeria goment don sue Meta incorporated, wey be di owners of Facebook, Instagram and WhatsApp platforms for 30 billion naira. Di Advertising Regulatory Council of Nigeria (ARCON) na dem carry Meta on go court for Abuja on behalf of di Nigeria goment. According to di statement from di council DG, Dr. Olalekan Fadolapo, ARCON explain why di council dey sue Meta. ""Di Advertising Regulatory Council of Nigeria don carry Meta Platforms Incorporated (wey be di owners of Facebook, Instagram and WhatsApp platforms) plus dia agent AT3 Resources Limited go Federal High Court, Abuja."" ARCON say dem dey sue Meta say dem engage in unlawful advertising inside di kontri. ""Among oda tins, ARCON wan make court say e dey illegal for Meta Platforms Incorporated to kontinu di publication and exposure of different advertisements wey dey directed at Nigerian market thru Facebook and Instagram platforms without making sure say dem screen and approve di advert before exposure."" ARCON also wan court to declare say Meta action na violation of di extant advertising law inside Nigeria. Di Council say Meta kontinu exposure of adverts wey dem no screen and also make di federal goment lose revenue. As e be so, ARCON dey seek N30b in sanction for di violation. Di council re-state say dem no go permit advertising wey dey irresponsible for di Nigeria advertising space. ARCON say no be say dem wan regulate di online media space but instead na di advertising and marketing communications on di online platforms in line with dia establishment Act. If dis case go ahead, e fit bring Nigeria goment closer to dia goal of controlling social media space inside di kontri. Nigerian authorities don repeatedly try to regulate social media sites. For June, di goment issue draft regulations to “guide” di operations of international social media companies. Recently, di advertising regulator announce ban on di use of foreign voice-over artists and models in advertisements starting from di beginning of October." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cv2947rne5eo +sports Argentina beat Australia 2-1 to move on to di Quarter Finals Lionel Messi produce a moment of magic on im 1,000th career game as two-time champions Argentina beat Australia to reach di World Cup quarter-finals. Messi, 35, bin dey make im 119th appearance for im kontri and dem bin need di help of im brilliance to take dem through to di next round and a tie against di Netherlands on Friday. Though Argentina no too threaten in di first half, Paris St-Germain Messi score to spark wild celebrations from dia fans. Body sweet dem more wen Julian Alvarez punish Mat Ryan mistake to double dia advantage. Australia manage pull one back in with 13 minutes remaining wen substitute Craig Goodwin strike deflect from Enzo Fernandez. Dem for level small time afta through Aziz Behich ogbonge solo run, but im shot bin dey blocked by Lisandro Martinez sliding challenge as Argentina edge through. SECOND HALF FULL-TIME Argentina 2-1 Australia All over. Argentina go play Netherlands on Friday for a place in di World Cup semi-finals. 90+7 mins: Australia Garang Kuol almost send di game to extra time. Im shots from 10 yards out dey saved by Emiliano Martinez. 90+5 mins: Argentina get about four chances. Two shots dey blocked, den Lautaro Martinez shot dey saved by Mat Ryan feet and di rebound hit Lionel Messi and go wide. 90 + 4 mins: Lionel Messi almost score from di corner of di area but e shoot just over. 90 + 2 mins: Lionel Messi beat one man and win throw-in. INJURY TIME Argentina 2-1 Australia Dem add seven minutes more. 90 mins: Argentina keeper Emiliano Martinez catch one looping ball and go down as if e bin injure. 87 mins: Di ball drop to Argentina striker Lautaro Martinez for di box at di end of a long passing move but e snatch am and e roll wide. 85 mins: Lionel Messi run to catch one long ball forward but e no fit beat di defender. E bin dey offside too. 82 mins: Dundee United Aziz Behich almost score for Australia. E take on several players as e run wit di ball. E cut inside Nicolas Otamendi and but just as e bin wan fire shot, to make am 2-2, Lisandro Martinez block im shot and save Argentina. 80 mins: Argentina do a double change. Exequiel Palacios and Gonzalo Montiel replace Alexis Mac Allister and Nahuel Molina. 76 mins: GOAL! Australia don score. But na own goal. 75 mins: Lautaro Martínez pass di ball to Nicolas Tagliafico, e fire shot wide of the far post. 72 mins: Australia sub too. Newcastle new signing Garang Kuol na one of those wey come on. 71 mins: SUBSTITUTION Argentina goalscorer Julian Alvarez dey replaced by Lautaro Martinez. Nicolas Tagliafico replace Marcos Acuna too. 70 mins: Marcos Acuna put im head for im hands. E beat Milos Degenek and for get chance to score but di officials rule say e foul Degenek to reach dia. 66 mins: Lionel Messi of run from midfield, e beat several players, before e go around di box and beat some more players. Dem tackle am before e fit shoot. 63 mins: One Australia set-piece no do anytin. SUBSTITUTION Just afta di goal Australia bring on Craig Goodwin and Ajdin Hrustic for Riley McGree and Keanu Baccus. 57 mins: GOAL! Di Australia goalkeeper take one heavy first touch from a backpass and step past Rodrigo de Paul before e run enta Julian Alvarez. Alvarez take di ball from di goalkeeper and place am for di bottom corner of di empty net. 55 mins: Mat Ryan run out of im box to head ball out of play from Argentina. 46 mins: KICK-OFF Argentina 1-0 Australia FIRST HALF 45+2 mins: Half-time whistle go off and na Argentina 1-0 Australia. 45 mins: INJURY TIME Two minutes dey added on. 39 mins: YELLOW CARD Australia Milos Degenek collect card afta e catch Marcos Acuna for air. E be di second Australian who go dey suspended for di quarter-final. 34 mins: GOAL! Argentina 1-0 Australia Messi score. Di ball land near am near for di edge of di box from Nicolas Otamendi touch and Messi put di ball past Mat Ryan. . 33 mins: Behich foul Gomez and dem give dem free kick for a good place. Messi take am but e dey headed away by Harry Souttar. 28 mins: Corner for Australia. Riley McGree take am and e find Harry Souttar. Di defender jump over Nicolas Otamendi and head di ball into di ground and Argentina clear am. 27 mins: Corner kick for Argentina, Molina play am. 25 mins: Aaron Mooy corner dey headed away by Nicolas Otamendi. oice at the back. 20 mins: 20 minutes into di game and no too much action. 18 mins: Australia Aziz Behich enta di box, for di byeline, and Rodrigo de Paul stop am. 14 mins: YELLOW CARD Australia Jackson Irvine foul Marcus Acuna and e collect Yellow. 11 mins: Julian Alvarez dey offside as e run for one ball but Harry Souttar defend am well. 10 mins: Harry Souttar play one nice diagonal ball to Mathew Leckie but e no fit control am. 9 mins: Alexis Mac Allister dey fouled and Argentina get a free-kick 40 yards out. Lionel Messi touch give am to Australia. Argentina get di ball back and Julian Alvarez no fit control Nicolas Otamendi pass. 8 mins: Matt Ryan goal-kick enta Argentina hand. 5 mins: One cross hit Keanu Baccus for hand but di referee no give am. VAR too no give am. 4 mins: Argentina call for handball. VAR go check am. 3 mins: Argentina just dey knock di ball around for di back, dem dey try to feel dia way into di game. I min: Kick off! Argentina 0-0 Australia Australia only win in seven games against Argentina na for dia first meeting for 1988. Current Socceroos boss Arnold play for dat match. Argentina and Australia don meet eight times now, Australia win only one match out of di eight for dia first encounter for 1988. Charlie Yankos score two goals wey help Australia win 4-1 for Sydney. Since dat time, Argentina don win six of dia last seven games wit one draw. Na total of 20 goals dem score but Argentina get 13 while Australia get 7 Dis matches na Fifa World Cup qualifiers, International Friendly, Fifa Confederation Cup, International friendly and Bicentennial Gold Cup. Argentina win: 6 Australia win: 1 Draw: 1 Argentina Martínez, Molina, Romero, Otamendi, Acuña, De Paul, Fernández, Mac Allister, Gómez Villaverde, Messi, Álvarez Australia Ryan, Degenek, Souttar, Rowles, Behich, Leckie, Mooy, Irvine, Baccus, McGree, Duke https://www.bbc.com/pidgin/articles/cl7q4n1vzr4o +entertainment Yusuf Satia, actor death, biography, Kunle Afod and Nollywood dey mourn Actor Yusuf Satia of Yoruba Nollywood don die and di industry. dey mourn di actor. Im colleague, Kunle Afod, announce Satia death on im Instagram account on Wednesday, say di actor die on 21 July, 2020. Yusuf Satia dey happun exactly four months afta Veteran Yoruba filmmaker and Nollywood actor, Gbenga Ajumoko bin die. Veteran Nollywood Actor Gbolagade Akinpelu AKA Ogun Majek die about di same time last month, June 2020. How di actor die neva dey dey clear. Satia become popular for im role in a Yoruba drama, Pam Pam. Yusuf Satia don also be a fuji singer, according to tori and e get di time dem see am wit fuji legend, KWAM1, for various outings and shows. Di late actor no be social media pesin as im last post for facebook na March 4 2013 wen he post countdown to my birthday. Im full name na Yusuf Ojewale Satia and dem born for 9 March. Yusuf Ojewale Satia grow for Lagos state, southwest Nigeria wia e attend primary and secondary school. Afta im secondary school education, he gain admission to University of Lagos. He also get certificate from di John Curtin College of Arts for Australia. He die on di 21 of July and wetin cause im death neva dey clear. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53509436 +sports Osimhen, Pochettino, Conte, Kounde, Satriano, Paqueta plus all latest transfer news Paris St-Germain dey set to sack manager Mauricio Pochettino and dem plan to replace am wit Tottenham boss Antonio Conte. (Le Parisien via GFFN) Chelsea fit revisit dia earlier move for Sevilla and France centre-back Jules Kounde, 23, in di summer afta confirmation comot say Antonio Rudiger go leave di club. (Football London) Arsenal don take steps to sign Napoli and Nigeria striker Victor Osimhen, 23. (Gazzetta dello Sport via HITC) Manchester City striker Gabriel Jesus, 25, don refuse to commit im future to City beyond di end of dis season. (Guardian) Arsenal believe dem fit complete summer deal for di Brazil international. (Mail) Chelsea and Tottenham dey monitor Inter Milan forward Martin Satriano, 21. Di Uruguayan currently dey on loan for French club Brest. (Mirror). Newcastle-linked Brazil international midfielder Lucas Paqueta, 24, don tell im current club Lyon say im go make decision on im future at di end of di season. (Evening Chronicle) Leeds don send scouts to watch Cologne German centre-back Timo Hubers, 25. (Football Insider) Former Manchester United midfielder Roy Keane don emerge as surprise candidate for di vacant manager position for Hibernian. (Times) Roma don join di race for Juventus and Argentina forward Paolo Dybala, 28. (Fichajes - in Spanish) Real Betis dey try to sign Real Madrid and Spain playmaker Isco, 30. (Marca) Egypt midfielder Mohamed Elneny, 29, say im go like to sign new contract at Arsenal even if im no get assurances over im playing time. (Irish Examiner) https://www.bbc.com/pidgin/tori-61167348 +sports Chelsea: Afta Roman Abramovich, who be di likely buyer of Chelsea before Friday deadline "As Friday deadline for di sale of Roman Abramovich's Chelsea dey upon, BBC Sport review who be di major parties wey dey so far. Di official deadline to buy di west London Premier League club na 21:00 GMT Friday 18 March, 2022. Although some final bids go likely dey submitted into di weekend as some known parties don already ask for more time. E still get more than 20 interested parties, but di number of confam bid dey likely to be 10-15. Chelsea go make a shortlist next week, and di preferred bidder go still need goment approval, wey go involve proving di source of funds and wia di money dey go next. Premier League owners go also need to sign off any sale and dem go do directors test - known as di 'fit and proper pesin test'.. Di asking price for di reigning Champions League and Club World Cup champions na around £3bn - although some pipo don describe am as ""excessive"". Dem bin stop Russian billionaire Abramovich initial attempt to sell Chelsea afta UK goment sanction am afta Russia invasion of Ukraine. Dis na as dem understand say Abramovich get strong ties to Russian President Vladimir Putin. One consortium wey ex-Liverpool chairman Sir Martin Broughton dey lead, plus London 2012 chief Lord Coe Di Ricketts family, wey get Major League Baseball team di Chicago Cubs, dey lead one bid from one group of investors Swiss billionaire Hansjorg Wyss and US businessman Todd Boehly don form part of one consortium to try to take over Chelsea. Now American PR executive Barbara Charone, British businessman Jonathan Goldstein and British journalist Daniel Finkelstein don join dem. London-based investment firm Aethel Partners, wey Portuguese entrepreneur Ricardo Silva dey head. British multi-millionaire businessman Nick Candy, supported by former Chelsea striker Gianluca Vialli, wey co-own Tifosy, one mergers and acquisitions company for di football sector Turkish billionaire Muhsin Bayrak say im na one of di pipo wey don launch one bid Oda parties wey dem report say e get interest na US billionaire and Philadelphia 76ers owner Josh Harris wey get stake for Crystal Palace, New York Jets owner Woody Johnson and one Saudi Arabia-based consortium. Abramovich buy Chelsea for 2003 for £140m. But for im statement e announce im intention to sell im ownership ""no be about business or money, but about pure passion for di game and club"". Im values di club at £3bn and e don borrow di club £1.5bn. But say im no go ask make dem pay back any loan. Abramovich say im go donate di proceeds of di sale to war victims. Di funds from di sale go go one charitable organisation or into a frozen account. Football finance expert Kieran Maguire say di £3bn price tag ""no dey too much"" given di size of Stamford Bridge. ""Most commentators take di view di money no reach wetin pesin go want going forward,"" Maguire say. ""E no get capacity to increase Stamford Bridge sake of e location for London so to move else where for London go dey very expensive."" Abramovich don own Chelsea since 2003, and di club don win 21 trophies during im tenure. UK goment bin seize im British asset wey include Chelsea, and Premier League disqualify am as di director of di club. Di Blues dey allowed to continue operating afta UK goment issue one special licence. Dis one also make sure say Chelsea 800 staff - plus hundreds more on matchdays - collect dia salary. And dem also allow existing season ticket holders to attend matches, but dem go need issue new licence for dem to fit sell di club. Premier League chief executive Richard Masters tok earlier dis month say: ""Di quickest one [sale of one club] wey we don do in 10 days, but dat one no be say dem no fit beat am. ""Normally na matter of weeks but e depend on di complexities and di number of potential owners.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-60797203 +politics Meet new cabinet ministers Kenyan President William Ruto appoint President William Ruto of Kenya on Tuesday don appoint im cabinet ministers and advisers afta im win di 9 August presidential elections. Di President retain one serving cabinet secretary, Musalia Mudavadi wey im appoint as di prime cabinet secretary. Im also appoint di former Central Bank of Kenya (CBK) Govnor Njuguna Ndung’u as di cabinet secretary for di National Treasury. Ndung'u na economics professor wey lead di central bank between 2007 and 2015,. Di professor win winning praise sake of say im preside ova di expansion of di financial sector. E also chop criticism sake of say im give priority to growth ova price stability for 2011. Below na list of ministers wey di President appoint: Prof Kithure Kindiki come from Irunduni village, for Tharaka Constituency. Im start im career for academia. Im acquire im Bachelor of Laws degree from Moi University, and later earn im master's degree in International Human Rights Law and Democracy and a PhD in International Law. Im earn both degrees from di University of Pretoria, South Africa. Prof Kithure Kindiki go im Twitter page yesterday to announce say im dey ready to serve. Prof Ndung’u na leading figure for di crafting of United Democratic Alliance (UDA) manifesto wey dem name di Plan. Im bin serve as Executive Director of di African Economic Research Consortium (AERC) wey dey responsible for di drafting of di Kenya Kwanza economic model afta im appointment for 2021. Aisha Jumwa Katana na politician and di current Member of di Parliament, Malindi Constituency. Aden Duale na Garissa Town MP. Di MP express im gratitude to President William Ruto afta im appoint am as Defence Cabinet secretary. Alice Wahome na Kandara MP. Di second term MP na lawyer and rights campaigner. Alfred Mutua na di immediate former Govnor of Machakos. Below na list of oda ministerial nominees: Di President also appoint former National Assembly Speaker Justin Muturi as di Attorney General, Mercy Wanjau as Secretary to di Cabinet, Monica Juma as National Security adviser and Harriet Chigai as di Women Rights Agency adviser.\nPresident Ruto cabinet ministers and advisers include 10 women and elected politicians. Di president bin promise 50% appointments to women but out of di 22 ministers, only seven be women. E appoint two more women as advisers and one female secretary to di cabinet. Some pipo dey see di appointments as reward for im loyalists wey campaign for am across di kontri. Politicians don make grand comeback to di cabinet afta di previous administration. For di last administration where Ruto be Vice President, technocrats nai full di executive. By-elections go dey for areas wia di senators and MPs wey Ruto appoint dey represent. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cnk8nkxekq1o +politics Ondo State Governorship Election: Oluwarotimi Akeredolu, Agboola Ajayi, Eyitayo Jegede na di major candidates wey go battle on 10 October "As di 10 October Ondo State govnorship elections don dey ginger, dis na good time to look at di main candidate wey go battle to lead di state for di next four years. Di election officer INEC don already promise say di Ondo elections go be di best di kontri don see - and e go better pass di Edo State elections wey happun like three weeks earlier. Officially na 17 political parties dey compete for di elections. Make we torchlight di main candidates wey go follow Govnor Oluwarotimi Akeredolu drag di leadership of Ondo. Di current govnor of Ondo na lawyer and di former Attorney General for di state. On 24 February 2017 dem swear am in for Akure as di govnor under APC. Profile Born on 21 July 1956 for Ondo, 'Aketi' as im friends dem call am do im primary school education for Akure and later go Ibadan for im secondary school. E attend University of Ife (now Obafemi Awolowo University) to study Law, and graduate for 1977. Dem call her to di Nigerian Bar one year after for 1978. Oga Ajayi na di current deputy govnor of Ondo State wey port from PDP go Zenith Labour Party. Although ZLP no be popular party for Nigeria, dem fit get mouth for di upcoming election, because di national leader of di party na Olusegun Mimiko wey be di state governor between 2009 and 2017. Oga Ajayi, under di APC party serve as deputy govnor but on 21 June, 2020 Ajayi comot APC to join PDP because ""di party don become poisoned space"", Premium Times bin report say e tok. Dis happen di day afta tori comot say armed police block Ajayi to comot from im official house for over hours. Kwanta bin don start between Ajayi and im oga Akeredolu wey im accuse say dey block im political career. Profile Dem born am as Agboola Alfred Ajayi, on 24 September 1968 for Ondo and for dia im do im primary and secondary education. E later go Edo to study Law for Igbinedion University, Okada. In di past Ajayi don serve as political party chairman for Social Democratic Party (SDP) and even Peoples Democratic Party. Eyitayo Olayinka Jegede na Senior Advocate of Nigeria, SAN wey go contest under di flag of PDP afta e defeat deputy govnor Ajayi during di brief time e dey di party. Profile E do im primary and secondary school for Akure Ondo and for some time, e also school for Ado Ekiti. Na for University of Lagos e take get im Law Degree between 1980 and 1983. For 1984, complete Nigeria Law School, for Lagos." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54399698 +entertainment Framing Britney Spears: Wetin her documentary reveal as she dey fight for freedom "Britney Spears don start to dey trend again for social media afta her documentary wey she do with The New York Times wey dem call Framing Britney Spears. Dis documentary really show wetin cause her public breakdown for 2007 wey cause am to shave her hair and also bash one car with umbrella. E also enta di mata of di media bin treat her as per paparazzi, and also di mata of her conservatorship. Na for November last year, she lose legal battle to comot her papa as conservator afta 12 years wey im don dey run her life. Britney Spears start her career for di Disney Channel show, Mickey Mouse club at di age of 11 wey she bin do with Christiana Aguilera , Justin Timberlake and Ryan Gosling. Afta di show tori be say she comot from Hollywood to go attend High school for Loiusiana. She tok for di interview say she bin pla basketball for school. Afta dat one, she comot with hit single, One More time and di documentary tok say she bin start to dey promote di song for inside shopping malls dem. She go on to release nine studio albums and one Las Vegas residency wey dem say dey super successful despite her public breakdown, relationship breakup and court order wey say make anoda pesin dey in control of her life (conservator) on top say she dey ""incompetent"". At di beginning of Britney Spears career for 1999, na im she start to dey date fellow Mickey Mouse star Justin Timberlake. Di relationship pack up for 2002 and na dat time according to di documentary one Maryland first lady bin tok fsay she go fit shoot Britney Spears on top tori say she cheat on JT. Di mata according to di documentary no reduce, when for di video of ""Cry Me A River"", JT cast pesin wey resemble Britney to spread di message. Even use am brag for interview say im bin knack di singer. Kim Kaiman, di senior director of marketing for Jive Records during Britney's rise tok say im no too see di papa, Jamie Spears wen she bin dey blow for di beginning. She say, di only tin di papa bin follow am tok na say, ""My daughter go rich sotay she go buy me boat."" Dem tok for di documentary say her parents bin spend evritin she bin get to boost dia pikin career. Bu while Lynne di mama bin dey enta New York every once in a while to make sure sa Britney blow, her papa no too show face. However e come back for 2007/08 wen tori be say Spears bin get mental kasala to take ova her life as conservator. Di documentary how how di podcast Britney's Gram bin make di hashtag #FreeBritney afta tori bin land say dem cari Britney lock for inside mental health facility afta she cancel her second Vegas residency. Di documentary tok say her brother Bryan bin even comot to tok she always bin wan comot from di conservatorship. One lawyer Adam Streisand wey tok say Spears bin want am to represent her for di first conservatorship hearing tok say she bin want pesin wey dey independent and professional to dey in charge of am and her estate. Im say she bin yell am ""I no want my papa to be my conservator."" One of di lawyers wey bin dey Jamie Spears team for di 2020 case to keep am as conservator, Vivian Thoreen tok say e dey rare to see conservative wey don successfully comot conservator ship. Na for November 2020, she lose legal battle to comot her papa as conservator afta 12 years wey im don dey run her life. Di documentary reveal say wetin cause di 2007 breakdown wey make di musician cut her hair and bash paparazzi car bin come tey-tey. Dis mata follow her divorce from Kevin Federline wey she lose custody of her two pikin even though she bin get frequent visits with dem. According to di documentary, how paparazzi bin dey treat he before dat time in make am scared to even come outside even as dem bin label am say she be bad mama. Di documentary reveal say pictures of am during dis period bin dey go for one million dollars wacth. And one of di paparazzi even confess for di documentary say she bin dey playful for di beginning of her career and bin dey follow chat with dem but na so her relationship with dem grow worse as time continue." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56013742 +politics Kaduna State strike: NLC leaders in hiding, Nupeng threaten nationwide, as El-Rufai fire nurses - Day three updates "Leaders of di Nigerian Labour Congress, (NLC) dey in hiding for Kaduna state as di workers strike for di state enta day three. One of di leaders tell BBC say, dem need to hide sake of ""threat to dia lives"", afta Govnor Nasir ElRufai declare dem wanted sake of ""economic sabotage"". Dis na di latest on di Day 3 of di 5-day strike by NLC for di North western state. Labour leaders say dem don advise dia members to also comot from NLC secretariat sake of say some thugs dey hang around di place to possibly attack protesting workers. Di 5-day warning strike by NLC for Kaduna state take different dimension on Tuesday wey end wit di sack of all Level 14 Nurses for di state. Day 2 of di protest wey don lead to di closure of health centres, schools, filing stations, electricity stations and di state secretariat don become national issue. Some suspected jaguda boys attempt to hijack di demonstration of di workers after dem fail for di attempt to disturb di protest around di NLC Secretariat for Kaduna. As dat one dey happun, tori come out say di state govnor Nasir Elrufai declare Ayuba Wabba, National President of NLC wanted on top accuse of ""economic sabotage"". ""Ayuba Wabba & odas for NLC declared wanted for economic sabotage & attacks on public infrastructure under Miscellaneous Offences Act. Anyone wey know wia im dey hide should send message to @MOJKaduna. handsome reward go dey,"" Elrufai tok for tweet. Di events for Kaduna don attract attention from Nigerians, Civil society organizations, and even federal goment as all di stakeholders dey call on both NLC and goment to dialogue. Muyiwa Adekeye, wey be tok-tok pesin to Govnor Nasir Elrufai announce di sack of all Nurses for di state wey dey below level 14 sake of say dem join di strike for time wen di state dey battle emergency health situation. ""Salaries wey suppose go to dem go become extraordinary occupational allowances to di health workers wey no comot from dia duty posts to fill di gap of those wey run from work. ""We don direct di Ministry of Health to advertise vacancies for di immediate recruitment of new nurses to replace those wey we dismiss,"" Adekeye tok. Di national leadership of the Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) threaten say dem go shut down all of dia facilities nationwide if any dem wunjure any of di labour leaders. ""di union tok say make no labour leader or worker wunjure during dis 5-day peaceful protests for di state. ""NUPENG, therefore warn say if any harm dey inflicted on any of di members of organized labour, di leadership of di union no go hesitate to call on all our members throughout di nation for a total shut down of all our services for di upstream, midstream and downstream sectors of di oil and gas industry,"" di National President and General Secretary, Comrade Williams Akporeha, and Comrade Afolabi Olawale tok for statement. Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) don tell Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai to stop to dey harass workers wey dey protest for di state. SERAP for statement wey dia deputy director Kolawole Oluwadare sign tok say e dey wrong for Kaduna state govnor to declare Labour pipo wanted sake of protest. Di group say protest na human right and non of di labour leaders don violate any law as dem dey protest. ""Govnor, Nasir El-Rufai and Kaduna state authorities must end di harassment and intimidation of NLC leaders and withdraw di illegal statement wey declare Wabba and oda leaders wanted. ""To declare NLC leaders 'wanted' simply for peacefully exercising their human rights dey antithetical to di Nigerian Constitution of 1999 [as amended] and di kontri international obligations,"" SERAP tok. Nigeria federal goment intervene for di clash between di organised labour and Kaduna state goment. Minister of Labour and employment Oga Chris Ngige say make all di parties ""immediately ceasefire"". Deputy Director of Press and Public Relations for di Ministry of labour and employment for di statement wey im bring out on behalf of di Minister Ngige say dem dey aware of all di controversy wey dey happun between Labour and Kaduna goment. According to di Minister, ""Dis na labour matter wey don snowball into a national strike and picketing by the two labour centres and affiliate unions. ""We hope and also pray say make di Kaduna state Govnor no escalate matters to such level wia e go become uncontrollable. We also appeal to di leaders of di labour centres to step down di action to make way for discussion."" E tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57169326 +politics Gbas-gbos between APC Oyetola and Labour Party Lasun days before poll "Osun State Govnor Gboyega Oyetola don deny di allegation from Yusuff Lasun, say im supporters attack im house on Monday morning. Lasun na di govnorship candidate of di Labour Party for di Osun State gubernatorial poll wey go happun on Saturday, July 16. Lasun claim say di attack happun for im house wey dey Ilobu for Irepodun local goment area of Osun State, southwest Nigeria around 1:00am on Monday, 11, July, 2022. Lasun also share fotos of di attack on im Twitter page on Monday. Lasun wey be former House of Representatives deputy speaker say di gunmen shoot im building as dem attempt to kill am, and add say di attack last for about 20 minutes. E say e get evidence say Govnor Oyetola supporters na dem dey behind di attack on im house. However, Oyetola wey be di candidate of di All Progressives Congress (APC) for di Saturday election, Oyetola describe di claim as lie. Di tok-tok pesin for Osun State govnor Ismail Omipidan tell BBC Yoruba say na Lasun plan di attack on im own house just to tarnish di image of Govnor Oyetola. “Pesin wey no win im local goment during primary election wen im still dey APC, e no win im local goment, na dat kind pesin we go dey afta?” Omipidan tok. Omipidan accuse Lasun say e won cause trouble on di day of election and na why e dey claim say dem attack im house. “My problem be say wia di pipo wey dey guard im house dey for midnight wen di attack happun? Dem dey sleep or dem no dey house. If no be Lasun plan am, we suppose see two pipo wey go confront di attackers,” Omipidan tok. Omipidan say Lasun no be threat to di re-election of Govnor Oyetola and challenge di former lawmaker to prove im allegations against di APC candidate. ""Di foto wey Hon. Lasun Yusuf dey try to paint dey very unfortunate sake of say Osun remain di most peaceful State for Nigeria and we go do everytin wey dey humanly possible to as goment to protect dis status,” e add. Omipidan say Osun goment and security need to investigate di mata as e accuse Lasun of planning to unleash violence on di pipo of Irepodun on election day." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn0gwyq5gdeo +sports Drogba: FIF election result see former Chelsea player fail in Ivory Coast federation presidential bid "Didier Drogba fail to become president of Ivory Coast football federation (FIF) as Yacine Idriss Diallo win Saturday elections. Former Chelsea striker Drogba, wey Premier League name for dia Hall of Fame dis week, lose for di first round of voting with just under a fifth of di vote. For di second round, Diallo, wey be businessman and current FIF executive member, squeeze out former FIF vice-president Sory Diabaté by 63 votes to 61. Saturday election for di political capital Yamoussoukro bin dey postponed several times since 2020, mainly over di ongoing issues wey concern eligibility of certain candidates, wit Drogba one of dem. After Fifa appoint normalisation committee to oversee Ivorian football, Drogba candidacy - wey dem initially reject over weda im get di required number of official backers - dem later accept am. Drogba play more than 100 times for di Elephants, including for di 2006 and 2010 World Cups, but for August 2020 dem tell am say im no dey eligible to stand for di election. After intervention from Fifa, di 44-year-old, wey win four Premier League titles, four FA Cups and the Champions League across two spells wit Chelsea, retain im hopes of running di game for di West African kontri. Yet Ivory Coast all-time top scorer suffer elimination with only 21 votes for di first round, wen Diallo (59 votes) and Diabaté (50 votes) make am through to di second round. Drogba achievements and ambitious programme for development of football for Ivory Coast bin don raise im popularity, and afta im defeat many of im supporters express their anger on social media on Saturday. ""Di presidents of clubs just kill Ivorian football, as im eliminate Didier Drogba,"" one user, Rosana225, tok. ""I hope say Ivorians no go take revenge by boycotting di 2023 Afcon."" Diallo get mandate of four years and di organisation of di 2023 African Cup of Nations, wey Ivory Coast go host, go be im first major challenge. Ivory Coast don win Africa Cup of Nations two times - for 1992 and 2015." https://www.bbc.com/pidgin/sport-61206653 +health Lockdown palava don kill more pipo dan coronavirus for Nigeria - Human Rights Commission Nigeria human rights joinbodi don announce say di security forces wey dey enforce di coronavirus lockdown for di kontri don kill more pipo than di virus dem dey try prevent. One report wey di National Human Rights Commission do, dem say dem don find up to eight separate times wey security forces kill reach eighteen pipo. Dis na as di kontri don confam only twelve deaths from Covid-19 disease. Di National Human Rights Commission also tok say so far dem don receive pass one hundred complaints from 24 states out of di 36 states wey dey Nigerian federation. Dem include Lagos, Ogun and Abuja wey federal goment recently extend di two week lockdown wey begin 30th March, for anoda two weeks. Na on February 27, Nigeria record di first case of coronavirus for di kontri. Oda parts of di kontri still get some type of restriction to avoid di spread of di Covid-19 disease and dem dey use di army and police to enforce dem. So far, 20 states for di kontri don get 407 confam cases of di virus. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52313213 +health Coronavirus in Africa: 10 innovations wey Covid-19 inspire "As Africa don pass more than one million confam Covid-19 cases, innovators on di continent don respond to palava wey di pandemic carry come wit different-different solutions. We bend down select 10 of dem. 1. ""Doctor Car"" robot Students from di Dakar Polytechnic School for Senegal don build multifunctional robot wey fit reduce di risk of Covid-19 contamination of patients and of those wey dey treat pipo. Di device get cameras and dem fit control am wit app. The designers say e fit move around di rooms of patients wey dey under quarantine, take dia temperature and deliver melecine and food to them. 2. Automatic hand-washing machine Nine-year-old schoolboy from Kenya Stephen Wamukota invent wooden hand-washing machine to help reduce di spread of coronavirus.Di machine allow pesin wey wan wash hand to use im leg match one pedal wey go turn water for dem, so as to avoid touch-touch of di water bucket. Stephen collect presidential award for June. 3. The RESPIRE-19 portable ventilator To solve di problem of ventilators wey no reach for Covid-19 wards for Nigeria, 20-year-old engineering student Usman Dalhatu build portable automatic ventilator to help pipo with breathing problems. Im plan now na to build 20 ventilators. 4. 3D mask printing Natalie Raphil na di founder of Artificial Intelligence company Robots Can Think South Africa. She dey use 3D printers to produce 100 masks per day for use in some of Johannesburg major hospitals. 5. Solar-powered hand-washing sink Ghanaian Shoemaker Richard Kwarteng and im brother Jude Osei decide to design one solar-power hand-washing basin to increase sanitation levels. When pesin hand near di sensor on di machine, soapy water go automatically comot. And afta 25 seconds, alarm go sound to mark di time wey World Health Organization recommend say make pipo wash hand for. 6. Web-based X-ray lung scans Engineers for Tunisia don create online platform wey fit scans lung X-rays t to try and determine if pesin fit dey suffer from coronavirus. Researchers for di National Institute of Applied Science and Technology for Tunis say di website dey 90% effective. 7. Police robots on lockdown patrol Still on Tunisia, authorities release police robots for di streets of di capital Tunis for April to enforce lockdown measures. Di surveillance robots, wey dem name PGuards, go spy on pipo wey dey waka for road and approach dem to ask why dem comot. Pesin go come need to show im ID to di robot. 8. Wooden money sanitiser Kenya mobile money agent Danson Wanjohi build one wooden device wey fit sanitise money wey pass through one hole for di machine. 9. Rapid 65-minute Covid-19 testing kit South African tech entrepreneurs Daniel Ndima and Dineo Lioma build Covid-19 testing kit wey fit produce result in 65 minutes. Normally, e bin dey reach up to three days for result to comot. Dia solution need to get approval from goment before dem fit release am. 10. Socially distanced haircuts For Ethiopia, barbers find way to cut customer hair and still reduce risk of catching Covid-19. Di barbers go tanda inside one constructed booth wey act like partition to separate dem from customers." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53791173 +politics 'Time to move on'- Atiku reply Wike and im team afta dem pull out of im campaign "Presidential Candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar don ask influential pipo of di party to join hands and move on wit di task of nation building. Atiku for one statement tok in response to move by di team of Rivers state Governor Nyesom Wike wey withdraw from di Presidential Campaign Council wey di party set up to plan and prosecute di general elections wey go shelle for March 2023. E say di pipo wey address di press get dia reasons wey want make dem withdraw from di Presidential Campaign Council. ""I no go speculate as to wetin those reasons fit be. ""Personally, I dey surprised wit dis withdrawal sake of say as I bin dey informed by officials of our party, apart from di Rivers State chapter of di PDP, all di remaining states of di federation submit names of pipo wey dem want for di Presidential Campaign Council"". Di presidential candidate also tok say on top calls for di resignation or removal from office of di PDP national chairman, Iyorcha Ayu, e no fit tok put. ""Di decision for Dr. Iyorchia Ayu to resign from office dey personal to Dr. Ayu and, neither me nor anyone else fit make dat decision for am"". E add say, ""as to di calls to remove Dr. Ayu from office, I go tok say, as one committed democrat and firm believer for di rule of law and democratic idea, and our party be one set up, wey dey organized and regulated by law and our constitution, e be my absolute belief say every tin wey we do for our party need to be according with, and match with di law and our constitution"". Atiku tok. Atiku also add say If dem go remove Dr. Ayu from office, e suppose be according to di law wey set out di basis for dat kind removal . ""Di tin wey even dey be say make pipo remember say di body wey get di power by law to start dis removal from office, don already pass vote of confidence on am,"" Atiku tok. Di former vice president also tok say di nation dey for pain of one multidimensional gbege wit insecurity, economic gbege, disunity and mutual mistrust and educational dislocations, among odas. ""I get plan to address dis issues and I don, graciously, gbab di ticket to lead our great party for di next year presidential elections, wit di singular mandate to come and lead di efforts to cure dis ills. Na sake of dis make me reach out to every single member of our great party to join me for di massive undertaking wey dey required to reset di ship of state, and helep rebuild our kontri"", e tok. Atiku further tok say: ""Every single pesin wey love dis kontri, as I do, dey needed for di hard tasks wey face us ahead as one nation, and dis include every member of di PDP. Na for dis light, therefore, I go urge those members of our party wey don state dia resolve to withdraw from di Presidential Campaign Council to rethink, retrace dia steps, and join us for dis efforts. Sake of dis, e be time, to move on wit di formidable tasks of nation building wey dey ahead of us,"" Atiku tok. Rivers state Govnor Nyesom Wike and im team on Wednesday morning announce for press conference say dem dey pull out of di Peoples Democratic Party PDP Presidential campaign council. Dis na becos dem dey insist say di current chairman of di party, Iyorchia Ayu must resign and give way for an acting chairman from southern Nigeria wey go lead di party to victory for di 2023 general elections. As dem rise from one meeting for Port Harcourt, di Rivers State capital early morning on Wednesday, members of di team vow say dem no go take part for Atiku campaign activities if di National Chairman, Iyorchia Ayu no resign. Di team members include Governor of Oyo State, Seyi Makinde, former Governors of Cross River and Ekiti states Donald Duke and Ayo Fayose among many odas." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp948vln8r4o +politics APC National Convention 2022: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table "All Progressives Congress [APC] 2022 National Convention na big focus for many Nigerians now. APC National Convention to chose new party leaders go hold on Saturday for Abuja. Nigeria ruling party highest political mass gathering dey happun one year and nine months afta dissolving dia National Working Committee [NWC] in June 2020. Electing new NWC members with substantive national chairman to replace Adams Oshiomhole go be di highpoint of di APC national convention. Last minute meetings-upon-meetings na im dey take place for presidential palace Aso Rock sake of APC. President Muhammadu Buhari na im dey host dis tok-tok to pave way for di 26 March, 2022 political gathering. Buhari on Thursday evening meet APC members of di national assembly, according to presidential sources. Thousands of politicians don dey already gada for Nigerian capital ahead of di big political meeting of di kontri governing party. After dat meeting, tori be say dem don resolve to work towards choosing consensus candidates on Saturday. Politicians wey di political party elect for dis long awaited meeting na im go lead di APC to contest di Nigeria 2023 general election. Since 2014 wen dem form Nigeria current ruling party - APC all those wey don be National Chairman emerge through a consensus arrangement. And as things be on Friday - a day before di party national convention - di All Progressives Congress fit adopt consensus candidates. Nigeria 2023 general election na big test for APC weda dem go remain di governing party of di west African nation afta Buhari full two tenures end. Nigeria election office - Independent National Electoral Commission [INEC] don announce new dates for di 2023 general elections. Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023. While govnorship and State Houses of Assembly votes go hold on March 11, 2023. For late February, President Muhammadu Buhari sign di Electoral Act Amendment Bill 2021 into law. Dis new law go affect di way political parties go prepare for di 2023 general elections. President Buhari, as leader of APC, begin hold series of meetings wit politicians of di party to settle all interests. ""Wen we bin come together to form di All Progressives Congress, nearly 8 years ago our goal dat time na National Salvation. ""Our resolve dat time bin dey unshakable, our motivation bin dey patriotic and noble"". President Muhammadu Buhari tok for meeting with members of Progressive Governors' Forum - wey be all serving state govnors wey be members of di party - on 23 March. Buhari also host di founding fathers of di party to a dinner on Thursday night 24 March. All Progressives Congress 2022 national convention build-up don witness plenti drama for dia party headquarters for Abuja. On Monday 7 March, 2022 police officers bin block all di entry point into di party office. From di whole issue, Niger State Govnor Abubakar Bello assume office as di acting chairman of di Caretaker Extraordinary Convention Planning Committee of di party. Di following day e approve di recommendation by di committee on zoning. Dis na di position wey di govnor of Yobe State, Mai Bala Buni bin dey hold before e travel abroad. Party leaders like govnors and lawmakers dem rush into di party headquarters to hold toks wit di Govnor Sani Bello, afta dat announcement. A week later, President Muhammadu Buhari meet Chairman of di APC Caretaker/Extraordinary Convention Planning Committee [CECPC], Govnor Mai Mala Buni for London. President Buhari, during di 15 March meeting, ask Buni to take charge of di APC convention and ensure say evri-evri go smoothly. Di Nigerian leader also write a letter to Chairman of APC Governors' Forum, Atiku Bagugu, wia e order am to ensure say oga Buni take charge immediately. A week afta di London meeting, court clear di way for Nigeria ruling party to hold dia big election alias National Convention on 26 March, 2022. Between November 2021 and March 2022 APC don shift dia convention many times sake of internal party gbas-gbos. Di party on Thursday block political appointees from voting as delegates at the for di convention. ""Di CECPC don declare say all political appointees, wey dey elected as delegates to di National Convention slated for March 26 no go vote. ""Na sake of di controversy surrounding Section 84 (12) of di Electoral Act, 2022."" APC tok for statement. ""However, political appointees fit still attend as observers."" di party statement add. Latest tori be say Senate President, Ahmad Lawan, don tok say ""unity list"" go ready and dem go make am public by Friday. Of all di main aspirants for APC National Chairman post, tori be say former govnor of Nasarawa State, Senator Abdullahi Adamu fit become di consensus candidate. APC national convention go hold for Eagles Square, Abuja and thousands of delegates from di 36 states and Federal Capital Territory dey expected to attend. Di outcome of dis important APC National Convention go affect who fit grab di presidential ticket of di goment party to contest Nigeria 2023 general elections." https://www.bbc.com/pidgin/world-60870937 +sports Premier league weekend report - Who dey top six now "Newcastle United impressive early season form continue to gain momentum with dia superb win for Tottenham wey lift dem up into fourth position for di Premier League table. Na Newcastle and Tottenham dem play di last match for di games wey happun for EPL for di weekend. Newcastle first score twice before Tottenham reply with one goal. Callum Wilson find di net from outside di box afta e collide with Hugo Lloris. Video assistant referee (VAR) award di goal afta dem check for a foul and handball, but notin controversial dey about di second goal before half-time. Na one poor clearance by Lloris wey Sean Longstaff intercept before Miguel Almiron beat one opponent and go round anoda to fire di shot under di Spurs keeper for im fifth goal in five league games. Spurs score through Harry Kane low header from close range, dem award am afta anoda long VAR check for offside, but Newcastle hold on to secure di points. While di Magpies extend dia unbeaten league run to seven games, Tottenham now don lost dia last two and dey in danger of going backwards. Dem currently dey third for di table wit 23 points, while Newcastle dey fourth wit 21 points. See di summary of di oda games for di weekend wey see Arsenal retain dia top position. Mikel Arteta describe Arsenal 1-1 draw with Southampton as ""a lesson"" as di Gunners drop points for only di second time dis season for St Mary's on Sunday. Stuart Armstrong score to stretch di Saints' unbeaten league run to three matches. Granit Xhaka bin don give di Gunners an early lead with im goal before Southampton equalise. ""E dey painful becos we bin wan to win again,"" Arteta tell BBC Match of di Day afta di game. ""Credit to Southampton as well. We no get complaints."" Gabriel Martinelli shot bin dey deflected and go wide while Gabriel Jesus bin dey denied by Southampton goalkeeper Gavin Bazunu as di visitors bin threaten to double dia advantage before di Saints score. Ralph Hasenhuttl team improve for di second half but bin need dat ogbonge last challenge from Elyounoussi to deny Jesus, who bin don break clear of di Southampton defence. Martin Odegaard bin tink say e don put Arsenal back ahead not long afta Armstrong equaliser, but im effort dey disallowed afta di ball bin go out of play during di build-up. ""We create big chances wey we bin no use,"" Arteta tok. ""For di Premier League, wen you no do dat wen you dey on top, you fit pay di price. Arsenal still dey top di table wit 28 points. Erling Haaland score twice as Manchester City equal a 91-year-old top-flight record for dia 3-1 win against Brighton for di Etihad Stadium. City bin dey complete dia 10th straight Premier League home win. Dem don score at least three goals for all of dem, sometin wey no side bin done do since Aston Villa, also across two seasons, for 1930 and 1931. Haaland now get ogbonge 17 goals in 11 league games - and 12 for im last five home games. However, na skippo Kevin de Bruyne score di best goal of di day, wen e curl one shot inside di top corner from 25 yards from Bernardo Silva inside pass. E end di hopes of a Brighton comeback, wey bin come up afta Leandro Trossard second-half effort beat Ederson from di corner of di area. As e be, Brighton still dey without a win under new boss Roberto de Zerbi, while Pep Guardiola side dey close to leaders Arsenal. Mancity dey second ontop di table wit 26 points. Chelsea and Manchester United play draw wen dem meet for Stamford Bridge on Saturday.\nNa ogbonge match for di two sides.\nJorginho goal for di 85th minute bin first give di Blues di lead.\nBut Casemiro header, inside di extra time of di match deny Chelsea of dat crucial win for Stamford Bridge. Chelsea currently dey fifth ontop di table with 21 points while Man Utd na sixth wit 20 points." https://www.bbc.com/pidgin/articles/clk2lpw49wro +entertainment Nengi BBNaija 2nd runner-up refuse to join whatsapp group for ex-housemates "Former Big Brother Naija reality TV show housemate, Nengi Hampson don reveal why she no gree join Whatsapp group wey di former housemates create. Nengi wey come out as second runner-up for di show, tell her fans for one Abuja meet-up say na becos she no like 'wahala'. For inside one viral video wey don begin spread for social media, she say: ""About di house, I be friends wit who I be friends wit. I no like to force friendships. I tink I be di only one wey no dey di group chat,"" na so she tok. Nengi also tok say ex-housemates wey she no mention dia name, approach her about joining di group. ""Dem approach me and I tell dem no I no want dey there. I no see di need to pretend or be in a space with pipo who... I no like wahala. If I know say dis energy no dey good for me, let me just stay..."" Although she no win di season 5 edition of di show, Nengi don bag many endorsements including appointment as Senior Special Assistant to Bayelsa State governor, Douye Diri. Nengi on receiving di appointment say she get passion to support girl child to di best of her ability and she wan also use her voice to fight gender based violence based on say she don experience am first hand." https://www.bbc.com/pidgin/world-55219242 +entertainment MBGN 2021 Oluchi Madubuike: Miss Abuja win Most Beautiful Girl in Nigeria Oluchi Madubuike, Miss FCT don win di Most Beautiful Girl in Nigeria, MBGN 2021 pageant. Di 33rd edition of di Most Beautiful Girl in Nigeria, MBGN happun on Saturday, di 18th of September for Eko Hotel, Victoria Island, Lagos. Di winner of di 2021 MBGN go represent Nigeria for Miss World pageant wey dem go do for Puerto Rico for 16th of December 2021. Dis year edition, na comedian Bovi and media personality Toke Makinwa be hosts. For 2019, Nyekachi Esther Douglas win di MBGN crown, she go on to win di Miss World Africa for di Miss World Pageant for 2019. She bin win di heart of many Nigerians with her reaction to who win Miss World 2019, Miss Jamaica. MBGN bin no hold for 2020 sake of coronavirus. Di 2021 edition of di pageant dey hapun 20 years afta MBGN Agbani Darego win di Miss World crown for 2001. Dem no do MBGN for 2020 because of Covid 19. Dis year dey boast of thirty seven ladies wey dey vie for di crown and di selection happun online. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58612480 +entertainment BBNaija evictions today: Maria, JMK, Sammie evicted from Shine Ya Eyes Big Brother Naija Maria, JMK and Sammie chop eviction from Shine Ya Eyes Big Brother Naija House on Sunday. Di housemates wey bin follow Maria, Jumoke [JMK] and Sammie collect eviction nomination include Pere, Cross and Queen . Head of house Liquorose save Peace wey bin dey nominated come replace her wit Cross wey bin no dey nominated. Jumoke Adedoyin [JMK] only join di TV reality show three weeks ago on 8 August, 2021. Di 23-year-old law graduate JMK bin dey ready to spice things up in di House by being di life of di party. She grow up for Ilorin Kwara State and bin hop say pipo go love her because she bring positive energy and mak pipo happy. Maria Nkechinyere na 29-year-old from Imo State wey say she be lovely pesin and promise to entertain. Maria serve as Head of House at some point for di house. She be realtor wet dey sell houses for Dubai. After di show, she say she go try venture into business for Nigeria. Maria dey single and hope to explore dating opportunities for di house. 26-year-old amateur filmmaker Sammie admit say im no dey above fighting for food inside Big Brother Naija House. Sammie gree say yes na because im love food so much. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58366860 +health Ebola outbreak 2020: Why di virus dey always come back Di Democratic Republic of Congo (DRC), don report fresh Ebola virus outbreak for di North West part of di kontri for 1 June, 2020. Dis latest outbreak na di 11th for DR Congo since dem first discover di virus for di kontri for 1976. Di kontri ministry of health bin tell World Health Organization say for Wangata dem bin discover eight Ebola cases and four out of di patients don die. Since April 4, DR Congo don record more than 30 possible cases of Ebola wey don cause di death of 18 pipo. Ebola dey quick spread. Small sweat or spit from pesin or animal wey get di disease fit infect pesin. According to di WHO, new Ebola outbreak go ever dey happun for Dr Congo because di virus dey live for animal reservoir wey dey for many parts of di kontri. Fruit bats na di main carrier of di disease, but pipo fit dey infected if dem come in close contact wit blood, organs or bodily fluids of animals wey get di virus like chimpanzees, gorillas, monkeys, antelope and porcupines. Di disease dey very rampant for dis area and e no go dey possible to destroy all di animals wey fit dey carry Ebola. As long as pipo dey touch and eat dem, possibility dey say Ebola go always return. Quick and well coordinated response to disease dey epp contain am and reduce di number of infections or infected pesins wey fit die from di disease. WHO Director-General, Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus say di health body go send team of 25 pipo go DR Congo for 2 June to support and see wetin dey happun. Di team go collect and test samples wey dem go carry go laboratory for confirmation. Dem go begin contact tracing and send additional supplies to di kontri to support di goment. WHO go also make sure say dem send essential health services go areas wey di outbreak serious. Five identified strains of Ebola virus na im dem don discover, di deadliest na di Zaire strain. Na dis strain dem see for di latest outbreak, and vaccine dey available to treat am. Dem develop di vaccine for 2014-2016, wen di epidemic bin dey very serious but dem no fit use am, because as at dat time e don late. E neva receive full licence for use but wit di epp of global efforts, dem prove say e dey safe for human use and dem don store 300,000 doses. WHO guidelines recommend say Ebola outbreak go occur before dem give licence. Di vaccine go dey available for all suspected patients, contacts and health workers wey dey at risk. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52888569 +sports Golden State Warriors win di NBA title - Full game report "Di Golden State Warriors beat di Boston Celtics to claim dia fourth NBA title in eight years. Dis go also be dia first title since 2018. Di Warriors win 103-90 for game six for Boston to fit win di series 4-2. Dem go also Be di first team wey dey go from di league's worst side to di championship in two years, afta dem finish di 2019-20 season with 15-50 record. Stephen Curry wey bin win di most valuable player for d regular season, gbab di NBA Finals MVP for di first time. Di 34 year old point guard bin average 311.2 points for di six games and score 34 points for Thursday's win with seven assists and seven rebound. In fact, di Warriors coach Steve Kerr hala say ""I dey thrilled for Steph. To me is na im crowning achievement to wetin don be ogbonge career. I obviously dey thrilled for everyone as plenti pipo get and for am. ""But di thing with Steph be say without am, dis no for happun"". Di Celtics bin dey lead 14-2 afta di first four minutes and 22-16 late into di first quarter. Then di Warriors come from back to give dem a 21-0 run to enta 27-22 with just ova 10 minutes to for di half. When Curry score three three-pointers for di first six minutes of di third quarter wey move Golden State lead to 72-50, na so im point to im ring finger. As well as 34 points wey Curry score, Andrew Wiggins score 18 points and Jordan Poole score 15 to move Golden State Warriors to dia first NBA championship in fours years." https://www.bbc.com/pidgin/articles/czvd8qze7gno +health Coronavirus cases: African American neighbourhoods dey suffer am pass for some America communities "Statistics from Chicago health officials don record plenti death of coronavirus on black Americans. Black pipo for Chicago don account for 70% of coronavirus deaths, even as dem be 30% of di whole population. Other cities wey get large black populations, plus Detroit, Milwaukee, New Orleans and New York, don become coronavirus hotspots. Di US don record nearly 370,000 cases of di virus and almost 11,000 don die. All ova di world almost 75,000 pipo don die from coronavirus and ova 1.3m cases na im dem don record. As of 5 April, 1,824 out of di 4,680 confam cases of Covid-19 wey dey Chicago na black pipo wey dey live for di area, city officials tok on Monday. Dem compare am with 847 white pipo, 478 Hispanic and 126 Asian Chicagoans. Chicago don record 98 deaths as of Sunday, and 72% of dem na black residents. Di difference dey show across di state, where black pipo na 41% of pipo wey e don die from Covid-19 , even as dia population na 14% of di whole of Illinois. Chicago public health commissioner Dr Allison Arwady tell tori pipo say black residents dey live on di average of 8.8 years less than di white pipo wey dey live di area. Mayor Lori Lightfoot say di coronavirus na ""devastating black Chicago"". She tok say dem go send city inspectors go different shops to make sure say everybody dey follow di rule of social distancing . Mayor Lightfoot sef raise di possibility say curfew fit dey di areas wey pipo dey gather for outside stores wia dem dey sell liquor. Though dem don call di coronavirus di ""great equalizer"", data dey suggest say di way di disease fit affect pipo from one neighbourhood to di other fit dey different For Michigan, African Americans na 14% of di population, but dem account for 33% of di coronavirus cases and 41% of di deaths, na so di figures from di state health department show am on Monday. White residents na about 23% of di recorded cases for Michigan and 28% of di deaths, according to di data. Detroit, Michigan, na about 80% black, and di city together with im surrounding towns dey account for around 80% of confam cases of coronavirus. Another similar difference happun for Milwaukee, Wisconsin, wey be one of di most isolated cities for di US. African Americans make up almost half of di 1,000 cases wey dem record for Milwaukee Country as of last Friday and 81% of im 27 deaths, even as black pipo na 26% of dia, Some 40% of coronavirus deaths wey e happun for Louisiana bin happun for di New Orleans area, where di majority of residents be black. Health officials bin tok before say di Big Easy residents dey suffer from obesity, diabetes and hypertension wey dey high pass di national average, and e dey make dem dey more vulnerable to Covid-19. Mayor Lightfoot say diabetes, heart disease and respiratory sickness ""dey common"" for black communities. Dr Arwady tell reporters say even everybodi for di city get access to doctor , ""we go still see di health disparities because of food deserts and lack of streets wey pesin fit dey wakabout"". Dr Cameron Webb, wey be African-American physician wey dey run for congress for di US state of Virginia, tell BBC News say na di pandemic dey highlight di racial and economic disparities for di US. ""E really dey expose di fault lines wey dey our society,"" he tok. Alderman Jason Ervin, wey be chairman of Chicago council black caucus, tell tori pipo for Chicago Tribune say di rate wey pipo no take dey follow di stay-at-home orders for di city dey contribute to di statistics." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52195828 +entertainment Lata Mangeshkkar: Indian singing legend don die at 92 "Popular India singer, Lata Mangeshkar wey sing tens of thousands of songs for her lifetime don die at di age of 92. She bin dey admitted for one hospital for Mumbai city for January afta she test positive for Covid-19. Di doctor wey treat her say she die of multiple-organ failure. Federal minister Nitin Gadkari confam di tori on Sunday. Mangeshkar get extraordinary career wey span over half a century, she sing more than 30,000 songs across 36 languages. But na her work for Bollywood, India Hindi film industry make her become national icon - pesin wey pipo sabi and respect well-well for di kontri. Indian government don announce two days mourning from Sunday, during which dinational flag go dey flown for half-mast throughout di kontri. Dem go give her state funeral. Her cremation go take place for Mumbai on Sunday evening. As di news break, tributes don begin pour in for Mangeshkar wey dey nicknamed as di ""nightingale of Bollywood"". President Ram Nath Kovind say di news dey ""heart-breaking"" e add join say her accomplishments go remain ""incomparable"". Prime Minister Narendra Modi say Mangeshkar death leave a ""void in our nation wey no fit dey filled"". Opposition leader Rahul Gandhi tweet say Mangeshkar's voice dey ""immortal"" and go ""continue to echo for di hearts of her fans"". Former Indian cricket captain Virat Kohli say her songs don ""touched millions of pipo around di world"". Several Bollywood stars also don express their sadness for di tori. Actor Hema Malini say she dey ""lucky"" to don perform several songs wey Mangeshkar sing. ""No one fit sing like her, she dey very special. Her passing away dey very saddening,"" she tell news agency ANI. Actor Manoj Bajpayee dey among several pipo wey say Mangeshkar death mark di end of ""a golden era"" for India music lovers. For decades, Lata Mangeshkar na di most wanted singer for India as every top actress wan make she sing their songs. She dey sell thousands of records and she get songs for 36 different languages. When she sing Aye mere watan ke logon (Ye, di pipo of my land), one haunting and soulful tribute to slain Indian soldiers for di 1962 war wit China for one public meeting, reports say Indian prime minister Jawaharlal Nehru for that time begin cry. Dem born Mangeshkar for Indore city, for central Indian state of Madhya Pradesh, on 28 September 1929. She begin learn music for di age of five from her father, Deenanath Mangeshkar, wey dey active for theatre. Afta her papa death, di family move go Mumbai (then Bombay), where a teenaged Mangeshkar begin sing for Marathi movies. She also act inside small roles in few films to support her family, but she later tok say her heart no dey for acting. ""I was happiest singing."" she tell interviewers. She get a big break in 1949 - for one haunting song called Aayega Aanewala for di movie Mahal. ""Soon every female actor want her voice. But she dey always dey busy and only a few fortunate music directors dey get di chance to make her sing,"" music director Mohammed Zahur Khayyam tok. Over di next few decades, Mangeshkar sing thousands of songs wey Bollywood biggest heroines across generations lip-synced. She dey nominated to di upper house of India parliament for 1999, but later tok say she bin dey ""reluctant"" to take it up and her tenure na ""anything but happy"". She receive India highest honour for civilians, di Bharat Ratna for 2001. For 2004, when she turn 75, one Bollywood biggest directors, Yash Chopra write for di BBC say im see ""God's blessings for her voice"". Mangeshkar wey no no marry get rich life outside her work, wit interests ranging from cricket to cars. Mangeshkar na passionate cricket fan and she get love for cars and di slot machines for Vegas. She also bin rub shoulders wit some of Bollywood brightest stars. Her younger sister Asha Bhosle also na celebrated Bollywood singer. Di two always dismiss any hint of sibling rivalry, and dem even dey perform together occasionally. ""We dey very close - we no dey compete wit each other,"" Bhosle tell BBC for 2015." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60277401 +entertainment Big Brother Naija Season 5: Ooni of Ife Youth Day suggestion to replace BBNaija Nigerian television series divide pipo opinion "Ooni of Ife don divide pipo opinion afta im suggestion to replace Big Brother Naija Nigerian television series. Nigerian youths on social media don dey divide on di comment of Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II, di imperial king of Ile-Ife, Osun state and highly respected Yoruba king for southwest Nigeria . Tori be say di king suggest say make goment replace di Big Brother Naija show wit oda show wey go promote di culture and value of di kontri. According to local tori pipo, im be tok dis one wen im host members of di National Youth Council of Nigeria for im palace. Ooni say di show dey misrepresent di ""goofness and integrity of di Nigerian Youths"" and add say many pipo dey vote for di show dan pipo wey dey vote for Nigeria election. But some Nigerian youth tok say no be di fault of di show say pipo no wan vote for Nigerian election as di elections dey come with different palava. Anoda user of Twitter say di kind need address economic policies wey no favour di youth first before im begin dey ask make dem stop di program. Some odas say di king dey tok im own for pocket. Dem ague say di show no be di problem of Nigerian youth. However, some odas agree say di show dey promote negative tins among youth." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53772067 +entertainment Met Gala 2022 pictures: Celebs looks for 'Gilded glamour' theme Met Gala in New York "Met Gala - one of di biggest fashion event - roll out red carpet for New York for global celebrities. Some 400 names from di world of music, film, fashion and sports, show off dia stuff for di lavish costume parade on di steps of di Metropolitan Museum of Arts. Di fundraiser don return to di usual early May slot afta di coronavirus pandemic bin make di organisers to cancel di one for 2020 and delay last year own till autumn. But di dress code for dis year own na gilded glamour, wey evoke America late 19th Century age of economic boom - some pipo see am as insensitive. Social media users yab dis year theme sake of say American working class families dey struggle to make ends meet during di highest inflation in forty years and for inside economy wey just shrink in di last quarter. Nicki Minaj fight don enta into a fight with a printer. Hudgens bn dey host Vogue coverage of di Met Gala, but her see-through Moschino ball gown designed by Jeremy Scott mean say she bin as well dressed as any of di guests she bin dey interview. Kylie Jenner bin wear a ruffled ivory ball gown from Off-White's fall/winter 2022 couture collection. Di entrepreneur and reality star show up wit di last from di late designer Virgil Abloh. One of di pipo wey attend na actor Riz Ahmed, and im dress like a chic labourer. ""Dis na homage to di immigrant workers wey keep di Gilded Age golden,"" im tok. Among di guests na di former presidential candidate Hillary Clinton. Mrs Clinton say she dey attend am for di first time in 20 years to celebrate di fashion and di spirit of America. Tickets for ogbonge celebrities na $35,000 and tables na $300,000. Met Gala party dey raise millions of dollars for di Metropolitan Museum of Art's Costume Institute. Dat na a fashion museum wey dia tens of thousands of exhibits dey closed to di general public. Singer Teyana Taylor and model Winnie Harlow both dey designed by Iris van Herpen. Di two outfits bin dey topped off with eye-catching headpieces. Taylor Marie Hill show off gorgeous royal blue dress with intricate floral embroidery. Chloe Kim, snowboarder and two-time Olympic gold medalist show for Met Gala 2022. Kodi Smit-McPhee know say na im turn to do di washing up. Di Power of di Dog star make im Met Gala debut, telling reporters say di event "" be a place wia pipo can go with zero boundaries and judgements on how dem want to express demsefs through fashion"". Singer Anderson Paak dance im way down di red carpet. Emma Chamberlain want you to know di midriff don come back. Billie Eilish put a gothic twist on di gilded age for dis year Met Gala. Fashion designer Pierpaolo Piccioli show off for Met Gala. Model Gigi Hadid wear one all-red ensemble wey featureone puffer jacket, corset and latex trousers. Jared Leto play spot di difference for di red carpet. Di actor (right) waka for di red carpet wit im close friend Alessandro Michele, di creative director of Gucci. Sarah Jessica Parker champion one unsung designer. Parker take dis foto her headpiece beautifully framed in di centre of di archway behind her. Joe Jonas and Sophie Turner bring a plus one enta Met Gala red carpet. Kid Cudi and Sebastian Stan add di colour for di ceremony. Gwen Stefani channelle one tennis ball. SZA hopes di Met Gala get narrow doorways. Actress Carey Mulligan dey covered in crystals wit her husband Marcus Mumford. Brooklyn Beckham and Nicola Peltz Beckham be like di newlywed valentines for di Met Gala 2022. NFL star Odell Beckham Jr (wey no be relation to Booklyn), bin dey among di men wey put accessories for dia outfits wit some stunning jewellery. Stormzy dey represent di UK for im first ever Met Gala. Di rapper tell reporters him bin dey ""nervous"" about im red carpet debut. Lizzo dey back from band camp. Actor Nicola Coughlin bring in her Bridgerton TV series character Lady Whistledown Editor in chief of Boy magazine Fredrik Robertsson wear one jumpsuit featuring silver structured fins. Singer Erykah Badu pose inside one patchwork top hat." https://www.bbc.com/pidgin/world-61304283 +politics Ondo state election: Residents tok wetin dem expect from di winner of di governorship vote Ondo residents tok wetin dem expect from di winner of di October 10, 2020 governorship election. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54445554 +health Coronavirus disease 2019: Malawi don become di first African kontri to burn thousands of expired AstraZeneca Covid-19 vaccine "Health authorities for Malawi don burn 19,610 expired doses of di AstraZeneca coronavirus vaccine. Dem say dis go reassure di public say any vaccines dem collect dey safe. Malawi go be di first African kontri to publicly do dis. Di World Health Organization bin done tell kontris make dem no destroy expired doses but now dem don change di advice. Pipo wey show to collect vaccine for Malawi low and health workers hope say dis move go ginger public confidence. For dia population of about 18 million pipo, di kontri get record of 34,232 confirmed cases and 1,153 deaths. Malawi bin receive 102,000 doses of di AstraZeneca vaccine from di African Union on 26 March and use almost 80% of dem. But di expiry date wey dey di labels na 13 April so dem remove di vials from di cold chain dem take store am. Malawi principal health secretary tell BBC say e dey unfortunate say dey gatz destroy di vials but di benefits of doing pass di risks. ""Wen news spread say we get vaccines wey don expire, we notice say pipo no dey come our clinics to get immnunisation again,"" na so Dr Charles Mwansambo tok. ""If we no burn dem, pipo go think say we dey use expired vaccines for our facilities..."" Dr Mwansambo explain say one of di reasons health workers no use di vaccines before na because e dey hard to ginger adults to collect di vaccine. Malawi no be di only kontri for Africa to get expired vaccines. Di WHO bin ask affected countries to keep di vaccines until dem fit establish whether e go still dey good for use. But dem tok now say make kontris destroy vaccines wey don expire. WHO advise say make manufacturers comot di expired doses from di distribution chain and safely dispose am. Oda vaccines wey dey now fit stay up to 36 months. Di challenge wit Covid-19 vaccines na say e just dey in use for less dan a year and no correct data dey around dia effectiveness afta long periods." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57175697 +entertainment BBNaija: Erica say she no hate Laycon - See oda tins di Big Brother Naija ex-housemate tok afta her disqualification "Big Brother disqualified housemate, Erica Ngozi Nlewedim don come out tok for di first time afta organizers of di show disqualify her. Erica apologize give everybody wey dey watch di show, all her supporters, fans, my family and friends, then add say she no hate Laycon ""I don apologize give di housemates before I leave di house and I go like to apologize to everybody wey dey watch di show, all my supporters, fans, my family and friends, I dey very sorry for my actions ""And I dey very sorry for saying those horrible words to Laycon. Laycon I no hate you, we get our disagreement but I no hate you. And to everybody wey I insult, Dorathy, Prince and all, I dey very-very sorry."" Erica address her quanta with Laycon Erica don address wetin go wrong with her relationship with Laycon wey be her padi-padi before for di lockdown house. ""I think na wen e start to dey tell pipo say I try to kiss am. To my knowledge di kiss only happun once and I dey drunk dat time. E know say if not for di alcohol, e for no happun in di first place. "" And e lie say I try to kiss am some other times. Once no be plenti times and e decide say e no wan tok to me anymore, so I dey wonder why e continue to dey about me to different pipo and making me look bad. "" Ngozi Nlewedim add say she think say di quarrel between her and Laycon fit dey settled because she no even get any negative feelings towards Laycon. ""One thing about me, whenever I dey vex, I just want to tell di pesin how I feel and within a few minutes e don dey ova and I think I don do dis ova and ova. so I no get any grudges against Laycon."" Oda things wey Erica address for di Interview ""I dey happy to see my loved ones and my supporters, I really need dis, so I dey happy to dey outside di house."" ""I noticed that I no dey fine being alone but now I know say I need to dey fine been on my own."" ""I really like having fun, dancing, dressing up, looking pretty, task and all di challenges, I love winning."" ""Both of us dey carefree, we both dey crazy and kind of complete babies too and our conversations just dey flow naturally, we dey very cool.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54068744 +entertainment Akuapem Poloo granted bail: 'Jail be depressing, I no expect say dem go jail me for 90 days' - Ghana actress, Rosemond Brown "Ghanaian actor Akuapem Poloo reveal say she no expect say dem go jail am for 90 days. She make dis revelation inside en address to de media after her release. ""I no expect say dem go jail me for 90 days. I no expect am at all"" Akuapem Poloo add. She also reveal say en seven-year-old son no know about en prison sentence, for en mind de mother dey act movie for Nigeria. De actress during de presser broke down in tears as she thank Ghanaian Prez Akufo-Addo for en intervention on de matter. BACKGROUNDAccra High Court release de actress on Ghc80,000 bail condition after en lawyers appeal de case. Lawyer Andy Vortia told BBC Pidgin she was entitled to bail because her case is before a court of competent jurisdiction. ""Convict applicant Akuapem Poloo has been restored to the state she was in before her conviction,"" Mr Vortia explained. The High Court granted her bail on basis that she is a first and young offender, the show of remorse, her guilty plea and welfare of the son. Akuapem Poloo has been ordered to report to the police twice a week, hand over her passport to the registrar of th de court and officially apply to the court if she has plans to travel. The Ghanaian actress was sentenced to a 90 day jail term last week for publishing nude photos of herself and seven year old son." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56875222 +sports Mourinho sacked: Tottenham Hotspur FC sack manager Jose Mourinho afta joining European Super League Jose Mourinho chop sack for Tottenham Hotspur FC on Monday morning afta 17 months as manager. Im sack land a day afta di English football club join European Super League wey dey make Premiere league para. Di Portuguese bin replace Mauricio Pochettino as Spurs manager for November 2019. 58 year old Mourinho guide di club to sixth position inside di Premier League last season. Spurs currently dey seventh for table as dem only pick up two points from dia past three league games. Spurs go face Manchester City inside di Carabao Cup final on Sunday. Di club knack out of the Europa League for March. No Premier League side don drop more points from winning positions dis season than Tottenham wey don drop 20 points in total. https://www.bbc.com/pidgin/sport-56798594 +health Covid-19 vaccination: Why Rivers State dey give vaccine without certificate "Covid-19 vaccination for Rivers State don get small k-leg. Officials don run out of vaccination seals wey dey dem put for di Covid-19 vaccination cards for di oil-rich state. Na so Joseph Urang wey be di State Immunizarion Officer tell BBC Pidgin. Dem don give out over 40, 000 doses of di Moderna vaccine for di first dose so far. But an extra 10,000 doses aftawards na without issuing a certificate to proof say pesin don take am. Dr. Joseph Urang explain say na dis concern make dem stop to give vaccination cards as dem don run out of di seals. ""Dem bin give us 40,000 doses to use for di first dose of di vaccination. ""But now we don give up to 50,000 doses so we don dip hand enter di second dose na im make shortage of about 10,000 dey. Dem give us seal for 40,000 and we don vaccinate like 50,000 and we still dey vaccinate pipo so you see wia di shortage dey. So right now we don exhaust di first dose of di Moderna vaccine and Abuja don promise to replenish us."" Dis one mean say an extra 10,000 pipo wey collect di Moderna vaccine for Rivers State for southern Nigeria no get a proof to show. Covid-19 vaccination card or certificate na requirement wey you gatz give authorities wey go wan know if you don take di vaccine or now. Without di card e fit dey difficult to proof to authorities say you don take di Coronavirus vaccine to immune yoursef against di virus. Dr Urang add say di State also don receive di second dose of di Astra Zeneca vaccine And dem also dey give out di vaccine but di second dose no come wit seal and dem don make request for am. ""We dey hope say between Monday and Tuesday we go get di seals but we no wan stop di vaccination process. ""So we instruct our workers say make dem vaccinate pipo but make dem no release cards. ""But dem must mark wia dem vaccinate dem and take dia basic information wey we put for register. Wen di seals dey available, we go get di information and fill di cards online."" Na wetin di heal official explain. Na from 23 August, 2021 dem begin give di Moderna vaccine against Covid-19 afta di State receive 81,000 doses of di vaccine. Dem also dey give Astrazeneca vaccine to pipo but give serious warning make pipo no mix di vaccine but wait to complete di vaccine. Click here to read how to register for Covid -19 vaccine in Nigeria ." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58546072 +entertainment BBNaija S6: Big Brother replace Head of House challenge wit ultimate veto power game Emmanuel win Big Brother cancel Head of House game wey supose happun on Monday inside di Shine Ya Eye TV Reality. Biggie also change eviction nominations wit ultimate veto power for di housemates. All dis day happun as di housemates for Nigeria biggest TV reality show face di last eviction nomination. Any pesin wey survive dis week go enta di last week of di grand finale. But instead of di usual Head of House challenge to give wey for weekly eviction nomination, Biggie bring new twist. Di ultimate veto power game na about points. Each housemate dey expected to gather as many points as possible. And at di end of di game, di housemate wit di most point go win di ultimate veto power. If tie dey, a sudden death game na im dem go play to determine di winner. For di rules of di ultimate veto power game - four obstacle lanes go serve as a race track. Di challenge then na to pick ping pong balls from one point to anoda end. Each lane get a different level of difficulty. Di less difficulty a housemate face, di less point dem go make. Lane one get 10 points, lane two get 30 points for each with ball wihile lane three get 50 points. Lane four get di most difficult challenge wit 80 points as e get a poll of water before a housemate go pick black balls for dia. If di ball fall off while dem dey cari di object dem go start all over again. Na only wen dem cross di line dem fit touch di ball and dem must stick to di marked lines for dia points to count. Di winner of di ultimate veto power game go dey crowned as di ultimate veto power holder for dis week. Di winner go get reward of immunity and power to choose di head of house. Each housemate go get exactly two minutes to run di course and score as many points as dem fit. Wit a total of 470 points, Emmanuel win di ultmate veto power. E mean say Emmanuel place for di grand finale dey guaranteed. Afta Biggie make am di ultimate veto power holder, Emmanuel appoint Liquorose as Head of House and Cross as Deputy Head of House. Whitemoney handover di HOH emblem to Liquorose. Di rest of di of di housemates dey all up for possible eviction dis week. Whitemoney, Pere, Angel, Saga, Nini and Queen dey at risk of being evicted from di TV reality show dis week. https://www.bbc.com/pidgin/58632618 +entertainment Sadiq Daba: 'Many of us for north enter film industry because of Sadiq Daba' "As tributes dey continue to pour in for late veteran broadcaster and actor Sadiq Daba, pipo for Kannywood movie industry say dem no go forget im contributions for dia careers. Di late Sadiq father na from Bauchi state wey dey northern Nigeria and di impact of im career for dat region na one wey dem no go forget. Popular actor and director Ali Nuhu tell BBC say di death of di October 1st actor na big loss to di movie industry and e go always dey remembered. ""When I dey grow up di programme Cock crow at dawn dey massive and I dey always remember im character 'Bitrus', I just pray say God go comfort im family and bless im soul."" For Kannywood director Babangida Bangis di loss dey deeper because of di role di departed play for im life. ""When I dey grow up na very few northerners dey on national TV and anytime I see Sadiq my mind dey sweet because i feel say e dey represent me, na later odas like di late Mohammed Danjuma join am And something wey dey always sweet us to see our pipo shining."" ""Personally na im roles for cock row at dawn and village headmaster motivate me to enter movie industry and I believe say many for Kannywood na so because when you see someone like you for TV dey do something it give you belief say u fit do am."" Senator Shehu Sani wey be friend to Sadiq share di last message wey e send am via Twitter saying God forgive our sins before angel of death capture our souls." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56276324 +business Malawi pay Mozambique $2,400 for charcoal wey dem tiff "Mozambique don tell Malawi to respect dia borders so dat di two kontries fit live togeda without wahala"" dis na afta sojas cross dia border go tiff. Dem tok dis one afta di raid wey happun for Calómuè, one border village for Mozambique district of Angónia, wey Malawi sojas use by force take seize 543 bags of charcoal from local traders. Tori be say di sojas plan to sell di charcoal. On Monday, one delegation from Malawi meet with local Mozambican administrators to apologise for di incident wey happun before dem pay dem $2,400 (£2,000) in compensation. One trader wey bin dey di meeting wia dem dey settle di mata praise President Felipe Nyusi as im help to settle di matter. Before now Malawi and Mozambique don get issues wey involve Malawia fishermen wey dey go fish for Mozambican territorial waters for Lake Malawi, wey dem dey call Lake Niassa in Mozambique. Oda katakata wey dem don face get to do with smuggling of maize and fuel, illegal slaughter of animals, cutting down of trees for wood and mining - but all dis one no involve sojas." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51947878 +entertainment MOBO Awards 2021 winners: Wizkid win two Mobos, Tiwa Savage perform, see winners list Wizkid win best international act and best African Act for MOBO Awards 2021. Di Sunday ceremony go be di first MOBO Award show wey go hold in person since 2017. Dis na as di award show bin take two year break for 2018 and 2019 before 2020 Coronavirus pandemic bin force di awards to dey virtual. Oda Nigerians wey participate for di awards na Tiwa Savage wey present di awards for Best male act and Tems wey perform for di award show. MOBO Awards 2021 hold for Coventry Building Society Arena. Artist and actress Leigh-Anne Pinnock and comedian and broadcaster Munya Chawawa na im host dis year MOBO Awards. Eddie Kadi, wey dey present BBC Radio 1Xtra Official UK Afrobeats Chart Show bin show as special guest. MOBO. or as dem dey call am, Music of Black Origin, na joinbodi wey dey celebrate black pipo music. Di founder of di joinbodi na Kanya King wey borrow money on top her house to start am. Na Ghanaian papa and Irish mama born Madam King wey bin start to make money for her family at di age of 17. Di British award show bin start for 1996 and don host plenti artists we include Beyonce, Rihanna Sade, Lionel Richie among odas. Di Awards claim sat dem don help di career of artistes like Stormzy, Craig David and Rita Ora. https://www.bbc.com/pidgin/world-59467378 +sports Lionel Messi birthday: 10 special moments for di Argentine footballer "Lionel Messi don get many ogbonge moment for im career - afta 627 goals and 34 trophies for Barcelona, and even get six Ballons d'Or ontop. Lionel Messi salary at di moment na 92 million dollars, according to investopedia. To celebrate Messi birthday wey be 24 June, we dey give you wetin we feel say na 10 of im most special moments for Barcelona and Argentina. BBC Sport bin ask our readers to rank di moments and dis na wetin you chose for di man wey turn 33-years-old today. Real Valladolid vs 1-3 Barcelona, 22 December 2012 Di Argentine record-breaking year of 2012 na something wey go dey hard to forget - 91 goals inside one calendar year. Messi bang 79 goals for Barcelona and 12 for Argentina - in just 69 matches for club and kontri. Barcelona 3-3 Real Madrid, 10 March 2007 Messi's first career hat-trick happun inside one of di biggest matches for football. Di teenager score all of Barca three goals for di 2007 Clasico - di first one of many to come for di Nou Camp. Na dat day Messi announce imsef to di world. Barcelona 5-2 Getafe, 18 April 2007 Messi goal for di Copa del Rey semi-final first leg 13 years ago na wetin pipo believe say na im best. Di goal resemble wetin Diego Maradona score against England for di 1986 World Cup. Messi pick di ball for im own half, beat about five defenders, e go around di goalkeeper and den chook am for back of net. Barcelona 2-0 Manchester United, 27 May 2009 Di match na di 2009 Champions league final and na di first 'Messi v Cristiano Ronaldo' match as di Portuguese footballer bin dey play for Manchester United dat time. Respect increase for Messi wey jump pass everybody for di box to head Xavi cross to score im first Champions League final goal. Barcelona 5-3 Granada, 20 March 2012 At just 24 years old, Messi break Barcelona goals and like di ogbonge player wey e be, na hat-trick e use. Even di former record holder Cesar Rodriguez, if to so say e dey alive, e go happy for Messi sef. Real Madrid 2-3 Barcelona - 23 April 2017 Sweet 500th Barcelona goal wey come for Injury-time against Real for 2017 na wetin win di El Clasico and one wey true fans no go ever forget. Messi win im number six Ballon d'Or to break record of di five wey Ronaldo get afta e score 54 times for club and kontri during 2018-19. ""I still get beautiful years to come for me,"" im tok as e dey collect di award. Barcelona 5-1 Sevilla, 22 November 2014 Anoda record, anoda hat-trick to take do am. Messi use free-kick to equal Telmo Zarra 251-goal record for La Liga, before e add two more goals to set new record. Barcelona 4-1 Arsenal, 6 April 2010 Messi score four goals for di first time for im career wen e face Arsenal for 2010 Champions League quarter-final. Di goal wey sweet pass na wen e lob ball over Manuel Almunia head. Germany 1-0 Argentina, 13 July 2014 Although one trophy wey Messi never taste na di World Cup, im don collect personal award from di competition with di 2014 Fifa Golden Ball. Di award for player wey play pass no really sweet Messi bell: ""Right now I no care about the prize. I bin wan take Argentina to di World Cup for all di pipo,"" Messi bin tell tori pipo." https://www.bbc.com/pidgin/sport-53150329 +sports Transfer rumours: Rudiger, Pogba, Rice, Mbappe, De Jong, Messi, Origi "Real Madrid dey close to agree free transfer deal for Chelsea defender Antonio Rudiger, di 29-year-old Germany defender dey ready to move to di Bernabeu on a contract wey worth at least £200,000 a week. (Guardian) Manchester City dey consider move for West Ham England midfielder Declan Rice, 23, wey don also be long-term target for Manchester United and Chelsea. (Telegraph - subscription) Paris St-Germain France striker Kylian Mbappe, 23, don dey linked wit move to Real Madrid in di summer, but dem no go make announcement on e future until afta di final game of di season against Metz on 21 May. (Marca) Norwich City want sign Bristol City English midfielder Alex Scott, Tottenham and Leeds already dey monitor di 18-year-old. (Football League World) Barcelona go dey willing to let Netherlands midfielder Frenkie de Jong, 24, leave for a fee of 70m euros (£58m), Manchester United dey interested. (El Chiringuito) Manchester United fit offer Barcelona 24-year-old England forward Marcus Rashford and 29-year-old Brazil defender Alex Telles as exchange for Frenkie de Jong. (Fichajes) New Manchester United manager Erik ten Hag go hold one-to-one Zoom meetings wit every member of di squad to assess who im want keep before e take charge in June. (Mirror) Dem go give Ten Hag ""significant funds"" to shape im Manchester United squad, plans dey to buy striker and midfielder. (ESPN) One player wey go leave Manchester United na 29-year-old France midfielder Paul Pogba, reports say im don leave di team WhatsApp group after e receive offers from Real Madrid and Paris St-Germain. (Mirror) Paris St-Germain go keep Argentina forward Lionel Messi, 34, for one more season but dem dey open to let Brazil forward Neymar, 30, leave di club. (Sky Sports News) AC Milan dey close to strike deal wit Liverpool 27-year-old Belgium striker Divock Origi. (Calciomercato) AC Milan, Chelsea and Real Madrid dey interested in Manchester City 31-year-old Algeria winger Riyad Mahrez. (Foot Mercato - in French) Juventus dey in talks to sign Argentina forward Angel di Maria, 34, on free transfer dis summer afta Paris St-Germain decide not to extend im contract. (Goal) Reims go let 19-year-old French striker Hugo Ekitike leave for 35m euros (£30m) in di summer. Newcastle dey expected to revive dia interest after toks wit di youngster in January. (Shields Gazette) Ekitike don also get interest from Liverpool, Chelsea and Manchester United. (Goal) Arsenal dey prepared to listen to offers for 26-year-old Ivory Coast winger Nicolas Pepe. (Sun) Germany midfielder Ilkay Gundogan, 31, say im go dey happy to end e career for Manchester City, but go also dey interested in move to di Turkish Superlig or MLS wen e contract end for 2023. (Sport 1 - in German) Liverpool 21-year-old defender Neco Williams, wey dey on loan at Fulham, say im no know wia im go play next season. (Wales Online) Udinese wan sign Arsenal Spanish defender Pablo Mari, 28, on permanent deal, following im loan spell. (Football London) Newcastle dey Eintracht Frankfurt 22-year-old French defender Evan Ndicka as dem dey monitor di player (Bild - in German; subscription)" https://www.bbc.com/pidgin/sport-61226479 +entertainment Superman bisexual: DC Comics reveal say di latest superhero go be bi "DC Comics don announce say im latest Superman, Jon Kent, go be bisexual. For dia next comic book issue, wey dem go release for November, Jon go dey in same-sex relationship wit im friend Jay Nakamura. Di storyline na part of 'Superman: Son of Kal-El', di series wey dey follow Jon as im take on di mantle of Superman from im papa, Clark Kent. DC Comics make di announcement on National Coming Out Day, one annual LGBT awareness day wey dem start for di US. Since dem release di series for July, Jon don already fight wildfires caused by climate change, stop one high school shooting, and protest against di deportation of refugees. For one earlier issue, Jon bin start one friendship wit Jay - one pink-haired reporter wey dey wear glasses. DC Comics say di two of dem go become romantically involved for di upcoming fifth issue, afta Jon ""mentally and physically burn out from trying to save everyone wey im fit save"". Dem neva reveal di details of di plot yet, but fotos wey DC Comics share show Jon and Jay dey kiss. Series writer Tom Taylor tell BBC say, wen dem first give am di job, im wonder ""wetin Superman suppose be today."" ""E strike me say e go really be missed opportunity if we replace Clark Kent wit another straight white saviour,"" Oga Taylor tok. To im surprise, before im go pitch di idea make Jon be bisexual, dem tell am say DC Comics don already dey tink di idea. ""Tins don shift over di last few years - ten years ago, five years ago dis one fit dey more difficult, but I tink tins don shift in a really welcome way,"" Oga Taylor tok am. Im tok say apart from di backlash from ""trolls"" on social media, reaction to di storyline wey positive dey plenti. ""We get pipo wey tok say as dem read di news, dem burst into tears- pipo say dem neva bin tink am say for dia life, dem go see demsef in Superman... literally di most powerful superhero for comics,"" Taylor tok. ""You go always get pipo who go use di old line of 'don't put politics into comics' - dey forget say every single [comic book] story ever don dey political in some way,"" im tok. ""People wey no realise say di [Marvel comic series] X-Men na analogy for di civil rights movement."" ""We try to bring those kain pipo with us, but we dey write for di pipo wey go hopefully see dis Superman... and say 'Dis Superman na like me. Dis Superman dey fight for tins wey concern me',"" im add." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58881051 +politics Liz Truss: UK Prime Minister don resign afta 45 days for office "UK Prime Minister Liz Truss don dramatically resign as prime minister afta only 45 days for di job. Di PM say di pesin wey go take ova from her go dey elected for one Tory leadership contest, wey go dey completed next week. Tory Members of Parliaments bin encourage Ms Truss to go, afta political kasala scata her goment, and pipo begin dey dump her economic policies. Her resignation come afta one key minister quit and Tory lawmakers disagree for one messy parliamentary vote. Na Tory members elect Ms Truss for September, but she lost authority afta series of U-turns. For one speech outside Downing Street, Ms Truss say: ""I know say I no fit deliver di mandate on which dem elect me by di Conservative Party."" Ms Truss say she go remain for post until a successor formally take over as party leader and King Charles III appoint am as prime minister. Ms Truss - wey enta office 44 days ago - go become di shortest-serving PM for British history when she stand down. For her speech, Ms Truss say she enta ""office at a time of great economic and international instability"", as war dey happun for Ukraine and living costs skyrocket. But her resignation come afta one key minister, former home secretary Suella Braverman, quit and Tory MPs disagree in messy parliamentary vote. Labour leader Sir Keir Starmer don call for immediate general election afta Ms Truss resignation speech. Liz Truss dey for office for just 45 days - di shortest tenure of any UK prime minister. Di second shortest serving PM na George Canning, wey serve for 119 days before e die for office in 1827. Trouble start for Truss wen her first Chancellor, Kwasi Kwarteng, spook di financial markets wit im mini-budget on 23 September. Since then, Conservative disquiet don turn into into widespread anger within di parliamentary party. Her stepping down today follow dramatic scenes for di House of Commons last night ova one vote on fracking. Truss premiership don dey for turmoil since her mini-budget last month, scata markets. New Chancellor Jeremy Hunt later scrap am. However, di prime minister say her goment deliver on providing support for energy bills and reverse a rise in National Insurance, tax on workers and companies. But Ms Truss resignation dey come afta a period of political and economic turbulence, wey force her goment to ditch tax cuts wey bring down di financial markets. Di prime minister sack close political ally Kwasi Kwarteng as chancellor and appoint Jeremy Hunt as his successor as she attempt to calm di markets. At Prime Minister Questions on Wednesday, Ms Truss insist say she be ""fighter, not a quitter"" afta Labour leader Sir Keir Starmer ask her why she neva resign. But more instability follow when Suella Braverman quit as home secretary and a vote on fracking fell into disarray, wit some Tory MPs accused of bullying." https://www.bbc.com/pidgin/63332637 +entertainment Obi Cubana Oba Anambra: Cubana Chief Priest oga mama burial fotos from Oba, Anambra State Nigerian celebrities dey gather for Oba inside Anambra state south east of di Kontri. Oba na di Igbo hometown of Nigerian nightlife entrepreneur Obi Cubana. And di celebrities show face for di burial ceremony of di mama of Obi Cubana. Nollywood actors Williams Uchemba, Kanayo O Kanayo, Alexx Ekubo na some of di celebs wey first land Oba. Singer Orezi also dey dia too wit di businessman. Socialite E-Money and im wife also honour Obi along wit Singer Kcee. Alexx bin share video for im Instagram page wey show as celebrities gather for table as they made jokes while having drinks. Tori be say na for December 2020 Obi Cubana mama Uche Iyiegbu die at di age of 75 years. And since she die di Chief Priest of Cubana Oga friends and associates don send am several gifts as support for di burial of late Ezinne Obi Iyiegbu wey many pipo known as Obi Cubana, say im receive ova 246 cows from friends for di burial for Afor Uzo Oba for Anambra State. Refresh dis page or visit again to see latest fotos as e dey happun for Obi Cubana mama burial in Oba Anambra https://www.bbc.com/pidgin/tori-57861537 +politics Ekiti governorship election: Candidates wey dey eye di seat Di govnorship election for Ekiti state South west Nigeria go hold on 18 June,2022. Anybody wey emerge for di election go become di 8th govnor of di state since Nigeria return to democracy for 1999. Di state na one of di few odas wia di Independent National Electoral Commission (INEC) dey do staggered election - dis na election wey no follow for di general election. Since di return to civilian rule, record show say no party don dey for goment back to back for Ekiti. Dis na because di state no dey experience political continuity. Belief be say voters for di state dey involve for di process well well and dat na why e dey easy for dem to change goment wey dem no like. Becos of dis, every govnorship election for Ekiti since 1999 don produce different winners from different political parties. Unlike oda elections for Ekiti state, dis year own go different becos no be di two main parties for Nigeria - Peoples Democratic Party (PDP) and All Progressives Congress (APC) get candidates wey pipo dey tok about - oda parties da candidates too dey di race. In short, di election no go be two horse race. Di emergence of Dr Wole Oluyede of di African Democratic Congress (ADC), former Governor Segun Oni of Social Democratic Party (SDP) and Chief Reuben Famuyibo of Accord don expand di contest. However, na sixteen parties dey contest dis election but sake of how pipo fit vote based on popularity and oda factors we go reduce di number of di main contenders to four. Di four na; Biodun Oyebanji, Debo Ajayi, Bisi Kolawole and former govnor Segun Oni. Though APC na di ruling party for di state, e no sure say dem fit retain power. Development for Ekiti state dey slow - dis fit be sake of continuous change of goment. Some of di issues wey opposition parties dey use campaign against di ruling party na mata wey concern; According to di Independent National Electoral Commission (Inec), Ekiti state get 988,923 registered voters but na 734,746 pipo don collect dia voters' card as at May, 2022. Di state get 177 registration areas, 22,244 polling units and for 16 Local goment areas. https://www.bbc.com/pidgin/tori-61753332 +sports Cameroon vs Egypt penalty shootout: Gabaski save two penalties as Pharaoh's reach Afcon 2021 final Goalkeeper Gabaski na im become di hero as im save two penalties for Egypt wey overcome hosts Cameroon for penalty shootout afta di game end goalless. Di win see Egypt progress to di Africa cup of Nations Final wia dem go play Senegal on Sunday. Hosts Cameroon bin hit di post two times during 90 minutes, first from Michael Ngadeu-Ngadjui header and den Samuel Gouet long-range shot also hit di woodwork. Egypt star man Salah bin dey quiet for much of di game, im bin curl one shot wey go wide for first half and almost profit from loose back pass but im fail to convert am. Di Liverpool man bin no need step up to take one of di penalties as Cameroon miss three of dia kicks. Gabaski save Harols Moukoudi and James Lea Siliki shots while Clinton N'Jie shoot wide. Di game bin boil over towards di end as Egypt coach Carlos Queiroz see red card for arguing wit di referee, im assistant Wael Gomaa collect card too. Both coaches go now no dey for touchline wen di Pharaoh's go play Senegal for di final on Sunday as Gomaa bin don collect yellow for quarter-final against Morocco. Meanwhile Cameroon go face Burkina Faso for di third place match wey di Confederation of African Football say go now take place on Saturday by 19:00 GMT. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60255921 +politics Buhari open border: 'Seme border dey closed' - residents react to President Buhari order to open all land borders "On Wednesday 16 December, di Nigeria goment declare open four of di kontri land borders, but wen BBC Pidgin visit one of di borders, we discover anoda tin. We torchlight say Seme Border, near di outskirts of Lagos still dey closed, even though di president Muhammadu Buhari mention am as part of di borders wey go re-open. On Thursday, our reporter see as officers of di Nigeria immigration Service dey pursue pipo wey wan pass through di border into di neighbouring Benin republic. Di officers too no gree make pipo pass from Benin into Nigeria except for pipo wey get special pass. Upon inquiry some officers wey no wan make we mention dia name say dem never get order from di top to open di border, say na until dem get di order dem go fit allow pipo to pass freely. However, some pipo still dey cross over di border of di two kontris through di back route, wey dey cost as as much as 3000 Naira ($8) for motorcycle trip. Afta di presidential announcement videos comot for social media wey show some residents dey rejoice say goment don open di border, but wen we sama dem questions, dem confirm say true true di officers neva begin allow dem pass through di border. Some of di residents express happiness say goment wan open di border, say plenti of dem don suffer well since goment close di border as di closure follow cripple dia businesses. Eze wey be driver for di area say ""Nigeria goment no gain anything for di border wey dem close, now Benin republic moni don get better value dan Nigeria moni sake of di closure"". BBC pidgin observe say dozens of security checkpoints dey for di road from Lagos to di border town and some of di officers dey extort commuters for di road. Di road from Lagos main town to Badagry, di nearest town to di border, dey in a very bad shape as person go spend over four hours for journey wey suppose take two hours or less. Nigeria goment bin close di kontri border wit some kontri for August 2019 to control wetin dem say na illegal importation of agricultural goods, drugs and weapons." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55335956 +sports Winbledom 2021 scores: Ashleigh Barty beat Pliskova to win Wimbledon ladies tennis title "Ashleigh Barty don win her first Wimbledon title. Barty beat Karolina Pliskova inside tensed final on Saturday 10 July, 2021. She don become di first Australian women champion since 41 years. Barty win di first 14 points to take early charge inside a 6-3 6-7 (4-7) 6-3 win. Dis dey happun on di 50th anniversary wen idol Evonne Goolagong Cawley first win hia. ""Dis dey incredible,"" Barty, wey bin drop to her knees in tears, tok. "" E take me a long time to begin tok am, to dare to dream am and say am."" After climbing up into di stands to hug her team, she tell di Centre Court crowd: ""I bin no sleep a lot last night, I bin dey think of all di what-ifs. ""I hope I make Evrione proud. ""I gatz to thank evri single pesin inside stadium. ""Una don make my dream so special."" Both women bin appear for di first time for di final of di grass-court Grand Slam - di first time since 1977 wey dis kain thing happun." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57783302 +sports Tobi Amusan set new African record Oluwatobiloba Amusan don win di 100 Metres Women's Hurdles event for di World Athletics Diamond League for Paris France. She set new African record of 12.41 seconds as she break Nigerian -Spanish Gloria Alozie African Championships Record of 12.77 for Dakar, Senegal for 1998. Di Nigerian female hurdler, don become number 3 for di world inside 2022. Na only number one Jasmine Camacho-Quinn (12.37 seconds)  and Alaysha Johnson (12.40 seconds ) na im dey ahead of her now. Na small tin wey make Amusan no win any medal for di 2020 Olympics wey happun for Tokyo, sake of say she start slow, she finish 4th. She start slow again dis time but pick up for middle of di race. Di Diamond League na di competition for di athletic season, annual series of outdoor track and field meetings wey World Athletics dey organise. Di 2022 Diamond League na di thirteenth season. Di competition na a revision to di top level athletics series since Diamond League foundation for 2010. Na 32 events dem dey compete in, and di dual-meet final format dey due to dey replaced by a single final, wey for expand di number of meetings to 14. Na top track and field athletes from around di world dey compete for di annual event. Oluwatobiloba Amusan na Nigerian Hurdler. Dem born her on April 23, 1997 and she from Ijebu-Ode She dey school for University of Texas, afta she finish from Our Lady of  Apostles Secondary school, Ijebu-Ode. She finish 4th for di 2020 Tokyo Olympics and she just set new African record. She be Nigeria National Champion and currently rank No 3 for di world. She don win plenti Gold medals for Nigeria, especially for di Commonwealth Games. African Games and di African Championships both for Relay. Wit dis new African record, Amusan go be one of di top athletes from Africa wey pipo go wan see how she go perform for di upcoming 2022 World Athletics Championship for Oregon, United States of America next month and di Commonwealth Games for Birmingham, England from July 28 to August 8. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cllj6yd67njo +entertainment Sadiq Daba biography: Cock crow at dawn and tins wey di ogbonge actor no go want make we forget about am "Di death of Nigeria actor and veteran broadcaster Sadiq Daba shock many pipo, as tributes don dey enter for im pesin, work and legacy. Tori na say Daba die on di evening of Wednesday, 3 March at di age of 69. Many pipo from di older generation for Nigeria go remember Daba face ontop dia television sets when e work as broadcaster for Nigeria Television Authority (NTA). By di late 70s im popularity grow well-well after e appear for di NTA-produce inside soap opera ""Cock crow at Dawn"", as Bitrus. But even younger pipo bin dey fortunate to see im performance, as Daba later act inside recent Nollywood hit feems like October 1, wey Kunle Afoloyan direct for 2014. Daba dey known for di ogbonge way wey im dey tok, especially when e dey speak English language. For 2017, e comot for public to announce say im dey battle leukaemia, wey bin make industry colleagues to support am wit funds for treatment. Feem director and producer Kunle Afolayan, wey be son of anoda ogbonge actor 'Ade Love' and fellow colleague wit Daba break di tori. For Instagram, Kunle leave simple message say You go dey missed ""Uncle S"". You make your mark. Former vice president Atiku Abubakar, for Twitter thank Daba for di ""joy wey you bring enter we homes"". Publisher Dele Momodu say ""you fight good battle"", as im reference di medical challenge wey di actor face for di later part of im life." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56276385 +politics Tinubu get all e take to lead Nigeria - APC "Di All Progressives Congress (APC) for Lagos don delare say di party national leader, Bola Tinubu, get all e take to lead di kontri. According to dem, if Tinubu decide to run for 2023 presidential election, e no go dey out of place if you check im political record. According to local tori pipo, APC Secretary for Lagos, Lanre Ogunyemi, tell tori pipo say Tinubu get every fundamental right as a Nigerian to become di next president. ""Tinubu get all e take to lead dis kontri and he get every fundamental right as a Nigerian to reason am; e now dey left for Nigerians to accept or not, e now dey left for di party to decide who go flag dia ship as presidential candidate for 2023. ""Weda e don brief us or give us sign, weda pipo dey against am or not, we dey sure say e get everything to lead dis nation,"" e tok. E add say di APC national leader don contribute to modern Nigeria and dey regarded as di Moses of dis generation. ""Whichever way e go, make we decide say if e go to di South; make we decide weda e go go to di Southwest or Southeast and wetin we dey reason na worth am, who fit who fit carry Nigeria go wia e suppose be."" E tok. Dis wan dey come even as for 2019, Tinubu deny rumour wey dey spread say im get plan to contest 2023 presidential election and take ova from President Muhammadu Buhari. Oga Tinubu wey also be former Lagos state govnor, tok say im no sabi di group wey dey carri im mata for dia head and dey campaign on behalf of am at dat time." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51625214 +sports Ballon d'Or 2021: Messi, Ronaldo, Lewandowski - Who go win am? "Anytime you hear Cristiano Ronaldo and Lionel Messi names togeda, wetin dey first come pipo mind na di rivalry between dis two great footballers. And di big question wey pipo dey ask, na who be di best among dia two. E don pass ten years wey football pundits and fans dey try to get correct ansa for dis question. Apart from di number of goals wey Portuguese and Manchester United striker Cristiano Ronaldo and Argentine and Paris Saint Germain forward Lionel Messi don score, records wey dem don break. Anoda tin wey dey put dia names for fans and pundits mouth evritime na di Ballon dÓr. Ballon d'Or (wey mean ""Golden Ball"") na football award wey dem dey give di pesin wey become di best footballer of di year. Na evri year di French News Magazine dey organise di award ceremony. Di Ballon d'Or na one of di oldest individual football award wey pipo value well well. Di award don dey since 1956, even though between 2010 and 2015 dem joinbodi wit FIFA come change di name to FIFA World Player of di Year. Di joinbodi waka end for 2016 and di award go back to im original name wey be Ballon d'Or. FIFA too go back to dia own yearly award wey be di Best FIFA Men's Player of di Year. Na sports writer Gabriel Hanot na im bring di idea and na through voting process wey sports journalists dey vote inside na im di winner dey emerge from 1956 to 2006. Afta di 2007 edition, dem come allow coaches and captains of national teams to vote too. Before-before, na only players from Europe na im dem fit nominate to win di award. For 1995, di organiser come expand am to include all di players from around di world wey dey play active football for any European club. Di award come become worldwide prize for 2007. Di 2021 Ballon dÓr na di 65th edition and na for inside October 8th dem bring out di list of pipo wey dem nominate to win am. See di Players wey dem nominate Di rivary between Cristiano Ronaldo and Lionel Messi wey don dey ground ova di last ten years go still continue, becos di way di mata dey go now plenti tins wey football fans dey use argue about di two players still dey ground. Out of di list wey dem announce on October 8, 2021, di ogbonde pipo wey dey inside na: Cristiano Ronaldo, Lionel Messi, Robert Lewandowski, Jorginhno, Karim Benzema, Isigne and odas. Lionel Messi na one of di players wey pipo feel say go win. Messi na oga for field wen im dey for Barcelona, but wen im comot go join Germain side Paris Saint Germain e tay small before im score goal. Messi don win di award six times and na di 7th one im dey pursue so. One tin wey stand Lionel Messi out dis year, na say im win im first major international senior trophy wit Argentina wen im win di Copa America and na im captain dem. E also help Barcelona win di Copa del Rey title for di 2020/2021 season. Wia wahala dey be say im neva break records di way im dey break dem before-before. Na 30 league goals Messi score before im tell Barcelona bye bye. Cristiano Ronaldo Pipo don dey ask weda Cristiano Ronaldo Go retire from football anytime soon as age don dey come for di guy side. As pipo still dey wait for dI big announcement wey go signify anoda era of football, di Portuguese player dey determined say im go end im career wit plenti Ballon Dór awards. Cristiano Ronaldo na im be di second highest winner of dis individual award. E don win am five times and na for di 2017/2018 season na im e win di 5th title wit Real Madrid, im toughest rival na Lionel Messi. Ronaldo wey dey 36 years bin dey play for Juventus before im cross carpet go back to im before-before club Manchester United. Im end di 2020/2021 season wit 29 league goals, and im win di Capocannoniere award for highest goalscorer and become di first footballer to finish as top scorer for di English, Spanish and Italian leagues. Lionel Messi na di only toughest rival Ronaldo get to equal Messi six Ballon dÓr awards. Robert Lewandowski Di German forward na anoda player wey pipo don tip to win di Ballon dÓr award. Lewandowski dey play for di German gaints Bayern Munich and since last season, Lewandowski don dey ansa im name well for field. Im score di first goal on Tuesday wen Bayern Munich beat Dynamo Kyiv 2-1. Im also write im name for di record book as di first Poland international wey score nine Champions League games back to back to back two times in a row. Na im be di hottest striker for Europe now and na 30 goals Lewandowski don score for 25 games wey im don play for club and kontri dis season. Robert Lewandowski na im dey put fear for Lionel Messi and Cristiano Ronaldo dem bodi. As e be so, Lewandowski fit stop Messi to win im record 7th Ballon Dór award and also block Cristiano Ronaldo a record-equalling 6th Ballon d'Or title if im win on Monday. For di German BundesLiga alone Bayern Munich and Poland striker don score record 41 goals inside 29 games last season, wey clean di longstanding mark wey Gerd Mueller wey die set. Lewandowski wey be 33 years win FIFA prize for best male player of 2020. Lionel Messi and Cristiano Ronaldo don win di last 11 out of 12 editions of di Ballon d' Or. Except di 2018 edition wey Luka Modric win afta Real Madrid win di Champions League dat season, and wen im help Croatia reach di final of di 2018 World Cup for Russia. Di Ballon d'Or no be for only men o, women too go win dia own. Some of di women wey dem nominate include : Marie - Antoinette Katoto wey dey play for Paris Saint Germain. She get Thirty-One goals and five assists for di Women Division 1 Jessie Fleming give Canada surprise Olympic gold medal. Na only five times she don start for di Chelsea Ladies dis year. Jennifer Hermoso na Barcelona player wey dey exceptional. Na 42 goals she don score dis year so far dis year wit 10 assists. She win treble wit Barcelona, and be di top goalscorer for Spain di third time back to back. Sam Kerr na Chelsea player na 40 goals she don score wit 17 assists, she win di Women's Super League and Continental Cup. She lead di Australian national team as captain and dem finish fourth for di Olympics. Alexia Putellas wey dey play for Barcelona get 37 goals, 27 assists. She win di Primera Iberdrola, Copa de la Reina, Women's Champions League. Na for inside Chatelet Theatre for Paris e go happun on November 29, 2021, wey be Monday You fit watch di livestream for eurosport.co.uk and ontop di Eurosport app on Monday night. Di time na from 7:30pm to 9:00pm GMT." https://www.bbc.com/pidgin/world-59434718 +politics Buhari go address 74th UNGA, follow Bill Gates do meeting for New York "Nigeria President Muhammadu Buhari go travel out on Sunday 22 September to attend di 74th session of di United Nations General Assembly wey dey happun for New York. Oga Buhari na di number five world leader wey go go address di United Nations General Assembly on di following Tuesday for America. Di topic for di dis year UNGA na ""Galvanizing Multilateral Efforts for Poverty Eradication, Quality Education, Climate Action and Inclusion."" Afta e address world leaders, di President go do meeting wit oga of big big companies dem like Aliko Dangote and Microsoft founder Bill Gates, on di mata of how Polio no go return to Nigeria and how how to bring investment come di West African kontri. In addition to those high-level meetings dem, some Nigeria officials wey follow oga Buhari travel go also attend some small-small programmers wey Ministries, Departments and Agencies (MDAs) organise dia. Di official Twitter handle of di Nigerian goment say Buhari go carri state governors Abdullahi Sule of Nasarawa, Abubakar Atiku Bagudu of Kebbi and Adegboyega Oyetola of Osun go New York. Ministers wey go go na di one of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama; of Environment, Muhammad Mahmoud; of Finance, Zainab Ahmed; and of Health, Osagie Ehanire." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49760331 +sports Odion Ighalo: Why Man Utd drop di Nigerian striker for dia training camp for Spain "Manchester United striker Odion Ighalo go miss di club training camp for Spain sake of fear of coronavirus outbreak wey fit make immigration for UK no allow enta back inside di kontri. Di Nigerian striker fly from China come Manchester last weekend afta di club sign am on loan from Shanghai Shenhua. United manager Ole Gunnar Solskjaer tell MUTV say ""Im for like come with di players so dat im go get to know dem,"". ""But di risk [of border restrictions wey don tight now] sake of di coronavirus we know want take chances."" Meanwhile, midfielder Scott McTominay and defender Axel Tuanzebe, wey get injury, go travel go Spain. Tori be say United go return back on Friday before dia Premier League game against Chelsea for Stamford Bridge on Monday, 17 February." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51425134 +entertainment BBNaija: Neo 'wash' Vee pant for Big Brother Naija lockdown house - See how fans react "Fans enta social media to debate whether dem fit wash dia partners pant ontop tori say BBNaija housemate Neo wash Vee pant for di show. On Wednesday night for di laundry room, Nengi shock as she hear say Neo dey wash Vee pant. Neo and Vee na di only couple wey make am to di top 5 of di Big Brother Naija 'Lockdown' reality show afta dem survive last week eviction. For inside video wey dey go viral for social media, Camera show Neo dey wash clothes, while Nengi and Vee dey look am. Di mata start wen Vee tell Neo say ""My dear, one pant dey miss"" di tin surprise Nengi as she first she reserve her comment but later voice out say ""Neo, you even wash pant join."" Vee reply her say Neo know say she na clean girl. Nengi come tell her say she be very lucky girl. Dis don make plenty fans react. See some of di reactions. Victoria Adeyele wey be 23 years old na musician wey base for Lagos, Nigeria. Dem born and raise her for London and she move come Lagos almost one year ago to begin her music career. She say her parents na Nigerians and say she dey enjoy acting, socializing and making pipo laugh. Vee say she no eva don dey relationship wey last longer than six month. Emuobonuvie Akpofure na 26 year old ride-hailing app driver from Delta State . E describe imsef as fun, tolerant, loving and smart. E also dey secretive. E biggest achievement na wen im win N 500 000 from one talent competition. E say e like wen pipo dey underestimate am and call imsef problem." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54277332 +politics INEC set September 2 for PVC collection for Kogi, Bayelsa elections Independent National Electoral Commission (INEC) for Nigeria don announce September 2 for di collection of Permanent Voters Card (PVC) for di Bayelsa and Kogi states election wey dey come. For statement wey di National Commissioner Festus Okoye sign on 20 August, di election office say pipo wey neva collect dia PVC get till 30 September to do am. Kogi and Bayelsa State go hold dia own govnorship election on 16 November, 8 months afta majority of states for di kontri don do dia own. Dis dey happun because of court order wey replace govnors for dos state, na so di date for four-year term also change. Di election office say because time wey no dey to conduct election for di two states, dem no go fit do fresh registration of voters, transfer of voter's cards and to reprint of voter's card wey don spoil. INEC also draw ear give parties say di dates wey dem don set, extension no go dey. Di last day for parties to deal with mata wey relate to dia primaries na September 5 while di last day for submission of candidate list and dia personal particulars na September 9 for INEC Abuja headquarters. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49407978 +sports Oscar Pistorius dey push for early release from jail Convicted murderer Oscar Pistorius dey go court to try to force South African authorities to hold parole hearing for am. Di former Paralympic gold medallist dey serve one 13-year sentence say e kill im girlfriend for 2013. Pistorius bin shoot and kill Reeva Steenkamp thru one locked toilet door, e claim say im think say she be tiff. Im dey ask for im early release based on wen im sentence start. Some challenges and rulings by di Supreme Court of Appeal (SCA) don lead to di confusion about wen im sentence become effective. Pistorius argue say im don already serve enuf time for prison to dey eligible for parole, so therefore authorities suppose look im mata to know weda dem fit release am early. For 2017, SCA say make Pistorius serve 13 years and five months for di murder of Miss Steenkamp – e overturn one previous, more lenient punishment of six years for di murder. Last year, di same court rule say make dem backdate im current sentence to October 2014, wen dem bin initially sentence am for a lesser charge of culpable homicide. Pistorius dey argue say backdating am mean say im for dey eligible for parole for February last year. E want Gauteng High Court to order di parole board to set hearing for am. If dem grant dat request, im go want make di hearing dey within 30 days of di order wey say so. But Atteridgeville prison, wia dem keep am, say di court of appeal give contradictory rulings. Di Department of Correctional Services also say e dey seek court judgement to establish di date wen Pistorius sentence bin effectively begin. Di murder of Steenkamp murder for Valentine Day nine years ago bin shock di kontri. For di trial wen dem show for television, millions of South Africa and pipio around di world, watch as Pistorius tok as im shoot im girlfriend four times bicos im think say she be tiff wey enta im house for Pretoria. But panel of appeal judges say as im arm imsef wit a deadly weapon, Pistorius suppose know say anybodi wey bin dey behind di toilet door fit die, especially wit di kain firearm training im get. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cqqyrplxp5xo +entertainment Headies award 2021 winners: Wizkid, Fireboy win, Burnaboy, Naira Marley lose and oda tins wey happun for di 14th Edition to reward 2020 performance Di 14th edition of di Nigerian Awards Music Show, The Headies don come and go but wetin happun during di show still dey make headlines. From di artistes wey win big, to di ones wey no collect any award and even di way di show go down, see di highlights from di 14th edition of di show. Di 14th Edition of di Headies happun even as coronavirus still be big issue around di world. Na limited amount of pipo dem allow for d show live, while everyoda pipo join virtually. Artistes like Master KG - Wey sing Jerusalema, do virtual performance. While oda artistes like Fireboy, Chike, Joeboy, DJ Neptune and Laycon perform live for di show. Di show organisers also present all di awards give di winners live during di show. Fireboy DML definitely na di Biggest Winner of di 14th Edition of di Show. Di artiste win four awards from four different categories. Fireboy Best R&B Single, Best R&B Album, Best Pop Award and Best Headies Revelation to make am di artiste wey pack di most awards go house from di show. Wizkid na also one of di big winners of di night. E win for two categories - Artiste of di year and Viewers Choice Award. While DJ Neptune song Nobody - Wey e do with JoeBoy and Mr Eazi win two awards. Many pipo bin dey expect say e go be tight race for di Artiste of The Year Award between Wizkid, Davido and BurnaBoy. But Wizkid na im claim dat title. Also, BurnaBoy get nominations for two categories - Artsite of The Year and Album of The Year, but e no win any. Some pipo go also expect Naira Marley to win the Best Street Hop Category but na Mayorkun win am. Pipo wey follow di show also get something to say about di organisation of di show as di live stream suffer interruptions several times and many pipo bin no fit follow di show bumper to bumper. And di award goes to...Well, trust celebs to turn up di heat and slay. Check out some celebs and how dem slay go di show. Best R&B Single Fireboy DML Best Recording of The Year Brymo Best Music Video of The Year 1 Milli - Davido By Director K Producer of The Year Pheelz - Billionaire by Teni Best Vocal Performance (Female) Niniola - Addicted Best Vocal Performance (Male) Praiz - Under The Sky Best Street Hop Artiste Mayorkun - Geng Rookie of The Year Bad Boy Tims - MJ Best Pop Single Nobody - DJ Neptune feat Joe Boy and Mr Eazi Best Collabo Ladipoe and Simi - Know you Best Alternative song Moelogo - I wonder Best Rap Single Falz - Bop Daddy feat. MS Banks Best R&B Album Fireboy DML - Tears, laughter and goosebumps Best Alternative Album Roots - The Cavemen Omah -Lay Viewers Choice Award Wizkid Songwriter of the Year Simi - Duduke Best Pop Award Fireboy - Apollo Lyricist on The Roll Ilbliss Goretti - Country African Artiste Recognition Award Master KG Headies Revelation Fireboy DML Best Rap Album God's Engineering - AQ Song of The Year Nobody- DJ Neptune feat. Joeboy and Mr Eazi Wizkid https://www.bbc.com/pidgin/tori-56148318 +entertainment BBnaija housemate Maria and Pere: Queen, Maria quarrel over Pere, HoH strong 'disrespect' warning "BBnaija housemate Maria and Pere di 'Shine Ya Eye' new Head of house, Pere don stir up di TV reality. Quarrel between two of di housemates on week three don cause tok-tok for social media. Maria wey be deputy head of house clash with one of di new housemate Queen ova Pere mata. While fans of di reality TV don dey hala and laugh at Pere style of leadership as Head of House afta e tell di housemates say e no accept any 'disrespect' as long as e remain HOH. Only three days inside di House, one of di new comers, Queen quarrel with Maria. Queen and Maria querrel for di Lounge over Head of House Pere. Wetin cause di quarrel na di question of weda Pere dey strategic or not. According to Queen, someone don bin tok during one conversation say Pere dey very strategic. Dem bin dey yan about im dealings inside di House and she agree with di statement. But e be like say Maria no agree with dat statement. She come make one comment about how Queen wey only just enta di don already know how Pere dey. ""I tok say na only two days and you dey act like you already know Pere. I no wan get dis conversation with you again."" Then Maria waka comot. Queen no like dat statement at all, she reply Maria say; ""Make I tell you something, Maria, e no dey take too long to know pipo for here. Youno get any right to say that. As Queen dey para, Maria answer back say make Queen respect her if she want dem to continue di conversation and na so kasala come burst. Di two of dem nearly enta fight until oda housemates including Pere separate dem and tell dem to calm down. Latest Head of House, Pere issue strong warning to im fellow housemates say; E no go tolerate any disrespect as long as e be di HoH. ""Di position come with respect. Disrespect me as a person but di emblem wey dey my neck signifies authority."" ""So there will be no disrespect as long as I be Head of House. we no be kids we be adult. I believe id on make mysef clear?"" Pere ask. Di 'Shine Ya Eye' housemate reply Pere say dem don hear wetin e tok. But fans of di reality show not take dis strong warning likely, dem begin react and call Pere different names. Some fans of di show refer to Pere as dictator, Idi Amin, Abacha, Military leader, deputy Jesus and plenti odas. Some even say na military regime e dey operate for di house." https://www.bbc.com/pidgin/58177670 +business Indonesia ban export of palm oil: Wetin e mean for Africa wia Nigeria be largest producer "Indonesia don ban export of any kind of palm oil wit immediate effect. So wetin e mean for Africa? Di Southeast Asian kontri dey account for more dan half of world palm oil supply, don sama ban on anykind Wetin cause di export ban be say Indonesia pipo don start protest against increase for di price of cooking oil. Di price increase don disturb dia local supply. So di question now be say wia Africa wey dey import oil wela go turn to next for supply. For 2021, Africa bin spend five billion dollars to import estimate of four million metric tonnes of palm oil from Indonesia and Malaysia. One tonne of palm oil be about $1,850 for di commodity exchange for Kuala Lumpar, Malaysia. E den add, anoda 150 to 200 US dollars for transport and handling costs, per tonne. Dis mean say, di real cost to deliver one tonne of palm oil anywhere on di continent be about $2,000. Wetin dey dia be say, di ban fit expose Africa largest producer of palm oil-Nigeria wey be former world largest producer for di 1960s. Nigeria bin dey produce one small 1.4m metric tonnes for 2021, compare to Indonesia 44.5 million metric tonnes. Di ban dey come just a month since global sunflower oil supply bin dey thrown off-balance. Na di Ukraine-Russia war, as dat one bin add pressure to household budgets. Indonesia restriction on exports, go now dey somehow for Africa pipo wey dey already struggle wit di effects of high fuel and food price sake of global supply chain wahala. Already, di price of product like soap and cooking oil don increase and di situation fit only get worse. Palm oil dey in use wella to manufacture vegetable oil. But e get plenti products wey dey comot from palm oil: Frying fats, cosmetics and cleaning products like soaps. Importers like India, Bangladesh and Pakistan go try buy more palm oil from Malaysia. But di world second-biggest palm oil producer no fit fill di gap wey Indonesia create sake of labour shortage. Indonesia mostly dey supply nearly half of India total palm oil import. While Pakistan and Bangladesh import nearly 80% of dia palm oil from Indonesia. Connie Magomu, di General Manager, National Oil Palm Project, for Uganda say di ban sef be opportunity. Magomu see am as good chance for Africa kontries to develop dia own palm oil sector. ""E dey very efficient for land use, as e dey produce more oil per unit area dan any oda crop wey we sabi (E dey give between four to 10 times more oil per unit area)."" ""E be also one good crop for poverty reduction sake of once e reach maturity for three and half years. ""E go dey harvested every 10 days for 20 to 25 years"", She add. Uganda don dey promote local production of palm and need at least 100,000 hectares to dey self-sufficient. Kontries for Africa wia di opportunity to grow and expand di production of di commodity be: Nigeria, Ghana, Ivory Coast, Sierra Leone, Uganda, Burundi, DRC Congo and Tanzania." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61260168 +sports Ivory Coast vs Egypt: Egypt comot Ivory Coast from Afcon 2021 to enta quarter final Egypt don beat Ivory Coast 5-4 wit penalty to enta di quarter-finals of di Africa Cup of Nations for Cameroon after 0-0 draw today. Di North Africans bin get di upper hand for di shoot-out wen substitute keeper Gabaski catch Eric Bailly ball for di third round of di penalty kick. Pharaohs captain Mohamed Salah naim score di decisive penalty wey send di seven-time champions to di quarter finals. Egypt go face Morocco for di last eight for Yaounde on Sunday, January 30 (16:00 GMT). Di match bin dey harsh on Manchester United defender Bailly, who bin perform well for di back as e wear rugby scrum cap sake of say e just return from head injury. Im be take a short run-up for im penalty and place di ball too close to Gabaski, wey dive to im right and stick out im left hand to push the ball to di bar. Di Zamalek keeper bin enter at di end of di second half after Mohamed El Shenawy get leg injury. Gabaski fit start against Morocco but na di extend of di injury wey Shenawy get go determine am. Na Ivory Coast first play, na Nicholas Pepe play di first penalty and e score. Zizo score for Egypt too making 1-1 Ibrahim Sangare score im own as Amr Solia score for Egypt 2-2 Eric Bailly naim first miss im penalty kick for Ivory Coast, e play am go hit bar still 2-2. Omar Kamal score for Egypt to make ma 2-3. Maxwell Cornet score im own for Ivory Coast to be 3-3. Mohamed Abdel Monen score for Egypt to make am 3-4 Wilfred Zaha score too 4-4 Mohamed Salah take di last kick and e score 4-5 Ball possession Ivory Coast get 55% while Egypt get 45% Shots Ivory Coast get 13 while Egypt get 21. Shots on target na 8 to 5 in favour of Ivory Coast. Corner Kicks, Ivory Coast get 9 while Egypt get 7. As di match hot reach na so fouls plenti too. Ivory Coast get 20 while Egypt get 16 Ivory Coast: Badra Ali; Aurier, Bailly, Deli, Konan; Kessié, Seri, Sangaré; Pépé, Haller, Gradel Egypt: El-Shenawy; Kamal, Hegazy, Abdelmonem, Fetouh; Fathi, Elsulya, Elneny; Salah, Mostafa, Marmoush https://www.bbc.com/pidgin/sport-60145758 +entertainment Dr Frabz profile: Wetin to sabi about Nigeria music producer wey celebrities dey mourn "Di news of di death of popular Nigeria music producer Dr Frabz enta di Nigeria social media space on Sunday morning as im colleagues dey mourn. For inside tweet fellow Music producer, SAMKLEF confam Dr Frabz death as im tok say im bin follow di music producer tok two weeks ago. ""I enta Maryland yesterday only to hear say you no dey anymore today. What a sad day! A brother don go, anoda producer done go."" Award Winning Recording Artiste, Radio&TVHost, Nikki Laoye follow express her shock to receive di news of im death. ""Dis na such terrible news, I just hear say dem shoot am, who do am?, I dey pained right now,"" she tok. Im real name na Ayorinde Faboro but plenti pipo sabi am as Dr Frabz. Dr Frabz na native of Ekiti state for di South West of Nigeria. He started music at di age of six wen he start to dey play piano. He don work wit plenti ogbonge Nigerian musicians like Eldee, Shank, Naeto C, Davido, Wizkid, Dagrin and others. One of im recent work na 'No room for Heartaches' wey im release for May, 2020. He don also produce songs like 'Cry for you' and many others dey for di list. Im be di CEO of Nsayne Entertainment, di record label wey im don use produce most of im songs. If you remember, Wizkid 'One question', Dr Frabz work on that song and im also play di piano during one BBC 1Xtra performance. E no dey clear how Dr Frabz die but one report wey neva dey confam tok say e fit be shoot dem shoot am." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56228119 +sports Senegal vs Egypt prediction: Head to Head as two Liverpool players, Mo Salah and Sadio Mane go meet for Afcon final Senegal neva win di African Cup of Nations (Afcon) before but dem don reach final of di competition several times. Egypt on di oda hand don win am - dem don win Afcon seven times. Na di two kontris wit di two best players for Africa dey play di Afcon 2021 final on Sunday. Di Teranga Lions don reach final again for di second time back-to-back. Di West African kontri bin reach final for di 2019 edition wia dem lose to Algeria. Meanwhile, di Pharoes dey hope to win di competition for di eight time. Pundits, alias sabi pipo for sports bin list Egypt and Senegal among di kontris wey be favourites to win Afcon 2021. Di two kontris no no start di competion well - Egypt lose dia first game 1-0 to Nigeria while Senegal also struggle through the group stage. But di Teranga Lions begin perform well as dem enter di round of 16. Na di same ginger wey Egypt too carry from di round of 16 dem take enter final afta dem beat host kontri, Cameroon for di semi-final. Di two teams get ogbonge players wey fit lead dem to victory. Mo Salah of Egypt and Sadio Mane for Senegal - both players na captain of dia teams and dem dey play for di same football club, Liverpool. Oda players na Senegal goalkeeper, Édouard Mendy and Egypt striker, Trézéguet wey im real name na Mahmoud Hassan. Egypt and Senagal don play each oda 12 times - dis na across competitions since 1986. Out of di 12 times dem don meet di Pharaohs don win six times while Teranga Lions win four time. Dem play draw for two games. Senegal get local coach, Aliou Cisse, wey be former National team player. Im don lose two Afcon finals. First na for 2002 as a player and 2019 as a coach. Meanwhile, Egypt coach na Carlos Queiroz from Portugal. Im na ogbonge coach wey don manage plenty teams both for club and national team. Queiroz no go dey available to coach im team from di sidelines sake of di Red Card im chop during dia semi-final match against Cameroon. Di Senegal vs Egypt match go happen for Olembe Stadium by 19:00 GMT Both teams start di competition slowly and bin no dey score goals like dat but dem don grow into di tournament. Unlike Senegal, Egypt never really light up di tournament wit goals as dem don prove to be team wey dey difficult to break down coupled wit di fact say dem get good goalkeepers. E dey hard to see where di goals go come from for dis match na why if e end for Full Time, Senegal go win. Senegal 1-0 Egypt. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60278939 +entertainment April Fool Pranks: Five beta jokes wey fit catch you today April Fool's Day no be new tin and evri year for dis time, evri pesin eye go dey chook make dem no fall mugu at any point in time. Different cultures get different explanation dey for how e take start but di endgame na e go make who ever fall victim to look like fool. You fit don fall for any of dis tricks already from before and fit still fall again because dem dey easy to fall for plenti times as dem easy to fool pipo. https://www.bbc.com/pidgin/tori-47764407 +business Jeff Bezos Amazon CEO don become first person to worth more dan $200 billion for di world Jeff Bezos wey be di richest pesin alive don break anoda record. Bezos don become di first pesin for dis modern history to make over $200 billion, according to di latest Forbes estimates of im net worth. Bezos, don wealthy pass e be before. Early Wednesday im cross anoda milestone as Amazon stock rise up by 2% as of Wednesday afternoon, according to Forbes, Bezos' net worth don go up by $4.9 billion, dis wan don make di 56-year-old di world first-ever persin to make $200 billion fortune. As of Wednesday, 26 August 2020, di Amazon founder and CEO worth $204.6 billion—nearly $90 billion more dan di world second-richest person, Bill Gates, wey currently worth $116.1 billion. Di coronavirus pandemic don help Amazon stock to go up by nearly 80% since di beginning of di year, and Bezos' net worth, wey be roughly $115 billion on January 1, don rise too. Bezos roughly 11% stake for Amazon maks up more dan 90% of im fortune. Na im get di Washington Post, aerospace company Blue Origin and oda private investments. But despite all dis, Bezos for even rich pass e be so if no be say e pass through di most expensive divorce settlement in history last year. He break up from im ex-wife, MacKenzie Scott, last July, but agree to give her 25% of im Amazon stake. https://www.bbc.com/pidgin/world-53927496 +sports Transfer news: Erling Haaland, Borussia Dortmund star fit move next week to Man City Erling Haaland summer move from Borussia Dortmund to Manchester City fit dey confirmed next week. Dis na according to separate sources wey tell BBC Sport. Sources tell BBC say dem don agree di £63m transfer for di Norwegian, and dem go soon announce am for Germany. City no gree respond to di widespread reports. Privately dem say na done deal - although dia definition of 'done' fit dey different to tori pipo. Dis na onto di fine detail wey dey involved for dis kain big-cash moves. Tori be say dem don agree on parts of di transfer virtually, City only need to trigger di clause to activate di transfer. Di transfer go be one of di biggest dis summer. Sports agent Mino Raiola bin dey involved in di discussions before im death. Now Raiola associates don take charge of di process to conclude am. Even though City dey very close to a second successive Premier League title wey dem achieve without a striker, Guardiola don always tok about im wish to get one. City bin try hard to get Harry Kane from Tottenham last summer but Spurs chairman Daniel Levy no gree sell am. And, wit two years left for Kane contract, Haaland deal dey easier to conclude sake of im release clause. At 21 years old Haaland statistics mad, e don score 92 league goals in 121 appearances for Molde, Red Bull Salzburg and Dortmund. Last year im become di youngest player to reach 20 Champions League goals. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61384119 +sports Connor McGregor: Dustin Poirier give MMA champion Knock Out for 2nd round "Connor McGregor don lose im first fight in one year against American MMA fighter Dustin Poirier. According to McGregor, di reason why im lose na because ""Poirier leg kicks bin dey good and my leg bin die, and I no dey as comfortable as I suppose be."" E tok dis one for im post match interview wia im say di defeat na hard one to swallow and now im just wan go stay with im pikin dem. Dustin Poirier tok for post interview too say im be di champion now, as e on win im past two matches. Poirier end di match for di second round wey im give McGregor plenti punches wey land am for ground before referee end di match. Di last time di two of dm meet na for September 2014, and na McGregor knock down Poirier for di first round." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55785262 +sports CHAN 2020: Morocco, scoring machine; Mali solid wall, who go take de trophy? Finals for sixth edition of African Nations Championship, CHAN 2020, competition for home based players for Africa na Morocco vs Mali, attacking machine and strong sentinel. Dis game weh football lovers say e go bi highly technical na between de best attack and defence for CHAN 2020. Morocco don score 13 goals out 58 goals dis far, produce CHAN top scorer before finals, Soufiane Rahimi wit five goals. De Altas Lions attacking machine also get players laik Ayoub El Kaab, but Morocco don also show say dia defense di leak. De team concede, three goals for group stage and quarter finals. For reach finals Morocco weh e start competition like locomotive, grind slowly, den gain momentum, energy for Group C. The Atlas Lions Morocco, 2018 title holders, di dream for take de trophy back for Morocco, for honour dia king and Morocco pipo. De Northern African team kick-started de competition wit 1-0 win against Togo, go for goalless draw 0-0 with Rwanda, den trashed the Ugandan Cranes, 5-2. Coach Houcine Ammouta squad, shame Chipolopolo of Zambia wit 3-1 beating for qualify for semi finials. Dia best time na wen Soufiane Rahimi butcher Indomitable Lions wit his killer shots, komot top scorer wit five goals as de team stop Cameroon dream for reach finals. Mali enta de competition for Group A wit 1-0 win against Burkina Faso, draw level 1-1 wit Cameroon, beat Zimbabwe 1-0 for qualify for quarter finals. De Eagles komot Congo for quarter finals on 5-4 on penalties afta draw 0-0 inside 120 minute. Den, beat dia West African neighbours Guinea 5-4 still on penalties, afta 0-0 draw to qualify for final. Mali coach Nouhoum Diane and e team dey for number four participation for CHAN di eye trophy weh deh loss for 2016 wen deh reach final. De Eagles di bank on Issaka Samake and defense line for stop Morocco but also Yakhouba Gnagna Barry wit three goals and e teammates for score and even snatch trophy from Morocco. Morocco-Mali CHAN between Northern and West look tough and go produce fireworks. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55964248 +entertainment Victor Olaotan dead: Nollywood/Tinsel actor Victor Toye Olaotan death afta 2016 accident "Nollywood actor Victor Toye Olaotan don die at di age of 69 years. Olaotan don dey sick for some years now afta im accident for 2016. Im bin get accident for 2016 as im dey drive go set for Lagos, Nigeria. Di accident keep am for bed for five years and three years to im death, im bin dey for hospital dey battle for im life. Di actor bin act as di main character for popular Africa Magic TV series Tinsel as Fred Ade-William. Inside statement wey im wife Julia Olaotan release on Friday morning, she say: She dey grateful im don finally rest from all di suffering. ""Im don try.E no easy to dey trapped inside your own body for five years. Im go fit finally rest now."" For 2018, di actor bin cry for financial support for im treatment for aboard. Nigeria Billionaire, Femi Otedola, later agree to help am pay di hospital bill dat time." https://www.bbc.com/pidgin/media-58355815 +entertainment Valentine's Day Messages 2022: Wishes Nigerian celebs send dia love on Val's Day "Valentine's Day wishes, cards and decor na im celebrities use celebrate dis special day of love in 2022. Most of dem celebrate di day wit fine fotos and sweet messages to dia better half, loved ones and fans. Saint Valentine's na dat time of di year wey pipo wan appreciate or show love to one special pesin or pipo wey dey dia lives. Valentine's Day wey dey always come up every February 14 na global observance. Dem set di day aside for pipo to express love, share love, give gifts and send messages to loved ones and friends. Here na wishes, cards wey Nigerian celebs send dia love on Val's Day 2022. Red and white na di colour of di day and celebrities come prepared wit dia outfits. Nigerian actress, Funke Akindele pose wit her husband JJC Skills to wish all dia fans, Happy Valentine. Akindele write say 'Let love lead di way' wit love emojis Actress, director, and producer Iyabo Ojo totori her fans wit dis sweet picture. Ex-Big Brother Naija housemate, Maria Chike Benjamin pen down emotional message give her fans. Maria write say 'Doubt say di stars na fire, doubt say di sun dey move dia assistants, doubts say truth na liar but neva doubt love. Happy lovers day.' Former Big Brother Naija housemate,Ngozi Nlewedim AKA Erica post say; 'I dey beautiful, I dey loved, I dey successful, I dey powerful! I'm all love!' Newly married Nollywood couple, di Adedimeji's also post nice foto to celebrate di valentine day. Lateef Adedimeji send sweet message im wife and fans. 'Wit you my sweet Rahmah, everyday na St. Valentine's day. Thank you for being di promised comforter, my friend, my confidant . You go always dey on top of my heart, everyday go dey filled wit renewed love and affection, happy Valentine's day baby... And to everyone out there. we wish you joy unlimited, skin deep happiness and di best of your heart desires. Remember to show love to someone today, and as my baby likes to say, in all you do... Let love lead!' Nigerian comedienne Real Warri pikin declare her undying love give her husband, Ikechukwu. She tag dia Valentine foto MyFavHuman Actress Lizzy Anjorin totori fans wit dis foto of she and her boo. Actress, Eniola Badmus post 'Happy Valentine's Day to di most important pipo for my life, MY FRIENDS, FANS AND FAMILY.' Nigerian actress Omowunmi Dada for her Valentine post advice pipo - 'Love yourself and love everyone around you, ALWAYS!' Public figures like Nigeria former Senate President, Bukola Saraki also enta social media to celebrate im wife of many years Toyin. Saraki share sweet words of affirmation of dia love. Valentine's Day or St Valentine's Day na yearly celebration wey dey happun every year on February 14. Na day wen pipo dey show love for anoda pesin or pipo by sending cards, flowers, chocolates or oda gifts wit messages of love. Di day get im name from one popular saint, St Valentine, although, plenty stories dey on who e be. Di popular belief about St Valentine na say e be priest from Rome for di third century. Emperor Claudius II bin ban marriage because e tink say married men be bad sojas. Valentine reason say dis no dey fair, so e break di rules and begin arrange marriages in secret. When Claudius find out, e throw Valentine for jail and sentence am to death. Na for inside jail, e fall in live wit di jailer daughter and on di day dem go kill am wey be February 14, e send love wey im sign ""from your valentine"" give him lover. Many pipo believe say di day originate from Roman festival. Di Romans bin get one festival dem dey call Lupercalia for di middle of February. As part of di celebrations, boys draw girls name from a box, dem go be boyfriend and girlfriend during di festival and sometimes dem dey end up married. Later, di church turn di festival into a Christian celebration and decide to use di day to remember St Valentine too. Small-small, pipo begin use St Valentine name to express dia feelings to pipo dem love." https://www.bbc.com/pidgin/world-60381198 +entertainment Coza: Nigerians dey look Davido 'explanation' wit side eye Nigerians for social media dey doubt di explanation wey musician Davido give about how im take appear for one viral video wey dey promote event for popular Nigerian church, Commonweath of Zion Assembly (COZA). Tori be say one of di church members bin post promo video for di church. Inside di video, one small girl and her mama siddon dey gist wit Davido about di program. Davido tok inside di video say im dey put God first in evritin wey im dey do while di girl and her mama ginger pipo to come for di event. Di video bin go viral afta di Head Pastor, Biodun Fatoyimbo repost am for im Instagram page. Na so pipo begin para say why Davido go pally wit church wey don dey inside news for plenti wrong reasons. Davido come release statement for im Instagram wia im deny say im no get anytin to do wit di video, say di pesin wey post di video use cunny way to make am show inside just to promote di church event. Di singer also add say im no get anytin to do wit di church, come warn make dem take di video down. But plenti Nigerians for social media no believe Davido explanation say im no know say di video na advert for di church. Many believe say di singer know wetin im bin dey do and im just dey try save face now wey pipo dey bash am. Di church member wey record di video, Elizabeth Omale don also clear di air say no be official advert for di church but na personal video wey she do to try raise awareness for di church program wey she claim say she dey passionate about. She tok say tori wey dey spread say Davido na official ambassador of COZA na lie. For recent times, COZA don dey inside news for negative reasons based on di rape accuse wey di Head Pastor, Biodun Fatoyimbo dey face from one of im former church member, Busola Dakolo. Dis kain reaction from kontri pipo ontop Davido so-called appearance for di church advert show say pipo still dey vex for di church no be small. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50856719 +health Remdesivir and coronavirus: US Food and Drug Administration authorise Ebola drug for COVID-19 treatment - See wetin we sabi about am "Di US Food and Drug Administration (FDA) don give go ahead for di immediate use of Remdesivir drug, wey doctors dey use treat Ebola, to treat coronavirus. Dis go ahead from di highest authority ontop drug and melecine mata for America mean say dem fit use di anti-viral drug (Remdesivir) on pipo wey dem hospitalise wit severe Covid-19 cases. One recent clinical trial show say remdesivir dey helep reduce di time of recovery for pipo wey dey seriously sick. But emergency FDA authorisation no be same as approval wey go need higher level of review. Sabi pipo still warn say make dem no use di drug wey Gilead pharmaceutical company develop to use treat Ebola as ""magic bullet"" for coronavirus. During one meeting wit US President Donald Trump for di Oval Office, Gilead Chief Executive, Daniel O'Day tok say di FDA authorisation na important first step. Di company go donate 1.5 million vials of di drug, O'Day add. FDA Commissioner Stephen Hahn also tok for di meeting say: ""Dis na di first authorised therapy for Covid-19, so we dey really proud to be part of am."" Dem originally develop Remdesivir to treat Ebola. Na antiviral drug wey dey work well to attack enzymes wey virus dey use multiply imsef inside cells for di bodi. Di drug dey cut di duration of coronavirus symptoms from 15 days down to 11 for clinical trial for hospitals around di world. Dem never publish di full details, but experts say e go be ""fantastic result"" if dem confam am, but e no be ""magic bullet"" for di disease. Drug go get di potential to save lives, reduce di pressure on hospitals and allow dem lift parts of lockdown. Di trial wey US National Institute of Allergy and Infectious Diseases (NIAID) run na 1,063 pipo participate Dem give some patients di drug and oda pipo receive placebo (dummy) treatment. Dr Anthony Fauci wey dey run NIAID tok say: ""Di informate wey we don gada show say remdesivir get ogbonge positive effect to reduce di time for patients to recover."" He tok say di results prove say "" drug fit block di virus"" and e dey ""open to di fact say we don fit treat patients. E never dey clear how di drugs dey affect make patients no die. Di death rate na 8% for pipo wey dem give remdesivir and 11.6% for those wey dem give placebo, but dis result no really dey important because scientists no fit tell if di difference dey real. E no dey clear who dey benefit. Di drug dey allow pipo wey go still recover to recover fast-fast? Or e dey stop pipo to need treatment for intensive care? Remdesivir dey work pass for young pipo or older pipo? Or pipo wey no get or pipo wey get oda disease? Dem suppose treat patient early wen di virus don reach peak for bodi? Dis na di important questions wey dem never publish di full details as drug go helep save lives and help goment to lift lockdown. Prof Mahesh Parmar, di director of di MRC Clinical Trials Unit for UCL, wey bin dey oversee di trial for di EU, tok say: ""Before dis drug fit dey available evriwia, plenti tins go happun. Dem go collect di data and results for regulators like WHO and FDA to look am well weda dem go license di drug and dem go still need relevant health authorities to fit get am for different kontris. ""As dis dey happun, we go collect more data from dis trial and oda ones on weda di drug no go make pipo die from Covid-19."" If medicine go stop make pipo no need intensive care, then hospitals no go too stress and social distancing go less. Prof Peter Horby, from di University of Oxford, dey run di world's largest trial of Covid-19 drugs. He tok say : ""We need to see di full results, but if we fit confam am, na fantastic result and great news for di fight against Covid-19. ""Di next steps na to get di informate about dis drug alias data out and work on how pipo go fit get remdesivir."" Di US data on remdesivir don come out at di same time as one trial of di same drug for China, wey dem report for di Lancet medical journal, though e show say di drug no dey effective." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52510003 +entertainment BBNaija housemates: Kiddwaya, Lilo, Wathoni, Eric, Tolanibaj kiss during first Saturday night party in Big Brother Naija Season 5 lockdown BBNaija housemates share first kiss during dia first Saturday night party in Big Brother Naija Season 5 lockdown. Kiddwaya, Lilo, Wathoni, Eric and Tolanibaj na some of di house mates wey lips gum each oda own as dem dey gbedu di night party for di live television reality show. Di first set of house mates to lock dia lips togeda, just 6 days into di 10 week TV reality show na Kiddwaya di son of billionaire Terry Waya and di Deputy Head of House Wathoni wey real name na Florence Wathoni Anyansi. No be only Wathoni and Kiddwaya kiss, Tolanibaj also lock lips wit Kiddwaya too in dat same night. Lilo and Eric kiss na im many fans see as di real deal on Saturday night sake of say di two don dey fall in love wit each oda inside di TV reality show. Afta di party, di house mates still dey jolly and on Sunday night dem go know di first set of housmates wey fit chop eviction. https://www.bbc.com/pidgin/53538578 +sports Bukayo Saka score to move Arsenal closer to Europa League knockouts Arsenal take big step towards qualifying for di Europa League knockout stage wit dia win against Bodo/ Glimt on Thursday night. Di win come afta Bukayo Saka collabo with di impressive midfielder Albert Sambi Lokonga and im effort bin hit one defender before e go back off im chin and past di goalkeeper. Bodo/Glimt enta di game with winning streak of 14 game win back-to-back but dem miss some ogbonge opportunities. E dey far from vintage Arsenal for Norway because Granit Xhaka and Gabriel Martinelli start to play afta an hour. But di win and di fact say im fit rest key striker Gabriel Jesus and defender Gabriel go sweet Mikel Arteta. Di win make Arsenal five points above Bodo/ Glimt with one game more. Di Gunners game against di PSV Eindhoven last month bin dey postponed sake of Queen Elizabeth II, e go happun next Thursday. If dem win, e go launch dem to di knockout stages. Saka bin dey impressive afta di Gunners 3-2 victory ova Liverpool on Saturday for Premier League and also for Norway. Di 21-year-old use lively from di start and fire for di six yard box afta just two minutes. E no follow di slow and patient buildup wey dey happun before and cut open di host defence. With di potential to challenge for di Premier League title, Arteta go dey ginger to get top spot sharp-sharp so e o fit rotate players and avoid extra-play offs for February. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cqvwgn9gl7qo +sports Super Falcons chop defeat from US for 2nd football friendly - Match report Nigeria women’s football national team chop 2-1 defeat from United States on Tuesday night. Rose Lavelle score di go-ahead goal and di U.S. women's national team win dia 13th straight match wit di full time score on 6th September, 2022. United States bin also benefit from one own goal to extend di team' unbeaten streak ontop American soil to 71 games. Nigeria and United States teams first meet on Saturday inside Kansas City, Kansas, and di US women football national team get away with a 4-0 victory. Nigeria bin miss six starters sake of injuries and visa issues. During Tuesday game, own goal give di United States early lead inside di 24th minute. But Nigeria equalized as Uchenna Kanu score after di haft time break. United States pull back in front with Lavelle goal wey come from Megan Rapinoe pass for di 66th minute. Both teams dey preparing for di 2023 Women World Cup, co-hosted by Australia and New Zealand. US don qualify for di World Cup for di CONCACAF W Championship in July. Di team win di tournament title to also secure a place for di 2024 Olympics. U.S. don win last two World Cups and dem get four titles overall. Nigeria, one of di most successful women teams in Africa, qualify for di 2023 World Cup by advancing to di semi-finals of di Africa Cup of Nations in July. Super Falcons bin finish fourth inside di tournament. Nigeria don qualify for every World Cup since di tournament start in 1991. Currently, di team dey coached by Randy Waldrum, former coach of NWSL's Houston Dash. United States dey head to Europe for dia next match against England at Wembley Stadium on October 7. While Nigeria go dey hosted by Japan for dia next friendly on 6th October, 2022. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cgx9vek5pjlo +sports Jimmy Greaves death: European football react to death of Tottenham highest goalscorer "Former England Striker and Tottenham highest goalscorer Jimmy Greaves don die at di age of 81. Di club confam dis one for statement say; ""We dey very pained to hear say di ogbonge Jimmy Greaves don die. ""As e no be only Tottenham Hotspur record goalscorer but also di finest marksman wey dis kontri don [England] ever see"". Oda pipo wey follow mourn di late footballer na British Prime Minister, Boris Johnson wey call am ""goalscoring legend"". Tottenham captain Gary Mabbut praise im playing skills and sense of humour. Uefa hail oga Greaves on top how im bin help Tottenham to become di first ever English club to carry Uefa trophy. West Ham do one minute clapping for Jimmy Greaves before dia match against Manchester United on Sunday." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58612482 +entertainment Who go win BBNaija Season seven? - Highlights of di show By Tunde Ososanya Di season 7 of di Big Brother Naija reality TV show tagged Level Up go end on Sunday 2, October 2022 and di winner go walk away wit di grand prize of 100 million naira. Dis year Big Brother Naija launch on 23 and 24 July 2022 and Biggie admit 24 housemates inside di house to compete for di prize as im separate dem into Level 1 and Level 2 houses for di first few weeks of di show before e later collapse di levels. Big Brother Naija na social experiment wey dey always generate conversation between pipo wey believe say na show wey no dey pass on useful information and odas wey believe say di reality TV show na beta show wey dey create opportunities for housemates to showcase dia talents and promote diasef. Despite di criticism, di reality TV show dey increase dia grand prize every year and experiment wit new ideas to make di show more attractive to dia target audience. Dis year finalists get eight housemates but na only six of dem be real housemates while di oda two na riders. Di six housemates wey dey contest for di 100 million naira grand prize na Bella, Bryann, Adekunle, Phyna, Chichi and Daniella. Di riders na Rachel and Chizzy. E mean say both of dem no dey contest for di grand prize. Dis na some of di highlights from di season 7 of di show. Beauty na di first housemate to get strike for Big Brother Naija Level Up sake of say she attack her fellow housemate Ilebaye ontop qwanta dia two bin get. Wen Ilebaye tell am to caution herself wen she bin dey raise her voice, Beauty go meet am for wia she siddon and remove her wig and cap, action wey give am her first strike for di house. Oda pipo wey go on to get strike for di show na Amaka, Sheggz and Bella. Beauty na di only housemate for di Big Brother Naija Level Up to get disqualified from di show. Di 2019 Miss Nigeria chop disqualification afta Biggie give am a total of three strikes. She get di second set of strikes sake of say she throw her wig and glasses at Groovy. Dis one happun one week afta di first strike wey she get. Wetin cause di kasala be say Beauty love interest, Groovy bin dance wit Chomzy, anoda babe for one of dia Saturday night parties and e vex di former Miss Nigeria. No season of Big Brother Naija wey no dey involve ships - na wetin fans dey call relationships for di house. Di Level Up season no dey left out. Ships no be only love relationship among housemates, e fit also be friendship and 'siblingship'. Bella and Sheggz aka Mr and Mrs Ikoyi na di most talked about ships and most consistent for di season seven show. Some pipo wey feel Sheggz no dey give Bella di respect wey she deserve bin hope say di Shella ship go sink but di two housemates no fit do witout each oda from start till wen Sheggz comot for di 9th week - a week to di finale. Even though dem dey get issues well-well, dem dey always settle dia issue as both of dem admit say dem no perfect and dem still dey get to know each oda. Beauty and Groovy ship na one of di early ships for dis year Big Brother Naija, but unfortunately di ship sink before e sail far as e all end wen Beauty dey disqualified afta she qwanta wit Groovy ontop accuse say she dance wit Chomzy. However, afta Beauty dey disqualified, e no tey wey Groovy move on wit anoda housemate Phyna for di show. Dat situation cause tok-tok among fans. Khalid and Daniella ship popularly called Khaniella bin sail wella and di housemates bin get pipo talking wit dia moments for di house. Afta Khalid chop eviction from di Big Brother Naija Level Up house however, Daniella get some moments wit Dotun wey later confam to Ebuka - di host of di show - afta dem evict am say im get feelings for Daniella. Hermes and Allysyn also start dia own ship for di house even though Hermes don openly tok about im two girlfriends outside di house. Pipo pick interest as Hermes na one of di housemates wey ginger well-well for di season. Eloswag and Chomzy ship dey confuse pipo sometimes sake of say dem put each oda for friend zone but e also get time wey di housemates become close. Despite say dia relationship no dey defined, di two housemates care about each oda and Eloswag dey always stand up to defend Chomzy anytime, any day. Asides di fact say di housemates go compete for fans dia love to fit win di grand prize, dem also need to navigate well-well all di twists and turns Biggie dey most times introduce to di show. Na one of such twists cause Amaka - wey bin dey quite popular wit fans her eviction wey shock pipo. Biggie bin ask housemates to nominate two fellow housemates for immediate eviction and di housemate wey dem nominate pass na Amaka. Na six of di housemates nominate Amaka and Biggie immediately send am packing from di Big Brother Naija Level Up house on a day wey no be eviction day normally. Some of di oda twists na di level three house biggie introduce to hide housemates wey chop eviction for some days - Doyin, Eloswag and Chomzy before e return dem to di main house and before e tell dem bye-bye. Anoda and perhaps di most impactful twist na di one wey give Chi-chi di power to to save two pipo and automatically level dem up to di final week wen she win Head of House. She pick Phyna and Daniella. Anoda twist for di show na di introduction of fake housemates and riders. Biggie bring in Deji and Modella as fake housemates wey later leave. Biggie also introduce for di first time di concept of riders. Di riders be Chizy and Rachael but di difference between dem and di fake housemates na say dem get di opportunity to stay till di end of di show even if dem no compete for di grand prize. Big Brother Naija na di Nigerian Franchise of di reality show Big Brother. Na reality show wia contestants dey live for isolated house and dey compete for a large cash prize by avoiding eviction by di viewers. Some analysts say BBNaija na Africa biggest reality show. Na MultiChoice Nigeria dey organise am. But di show dey draw criticisms say na big distraction for di youths and some pipo dey against am for not promoting 'morality'. But every year - during di months e dey air, e dey dominate social media conversations on Twitter, Facebook, Instagram and elsewhere. During di period e dey on, Big Brother Naija dey drive engagements and conversations for social media even as much as politics. Di programme dey air not only for Nigeria, but for 48 oda African kontries, to an average audience of 309 million viewers according to DSTV media sales figures. With peak viewing for di beginning of di programme, some eviction shows, and di finale. Daniella Daniella na 22-year-old native of Cross River State, south-south Nigeria. She be poet and spoken word artist. Her fans dey known as Dynamites. Phyna Phyna wey her real name na Ijeoma Josephine Otabor na actress from Edo State, south-south Nigeria. She be first class graduate of Engineering from Auchi Polytechnic, Edo State. Phyna say she dey also dey do hype-woman for clubs. Bryann Twenty-two-year-old Brian Chkuwuebuka Chiji aka Bryann na singer and songwriter. Bella Bella na 25-year-old University of Lagos graduate and content creator. Chichi Chinenyenwa Desire Okoebor na 22-year-old na exotic dancer by night and chef by day. She come from Edo State, south-south Nigeria. Adekunle Adekunle Tobilola Olopade na 27-year-old digital marketing consultant from Lagos. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd1yveere73o +entertainment BBNaija live: See why Big Brother give Kiddwaya second strike and warn Erica "Big Brother Naija 2020 housemate Kiddwaya don collect second strike for di reality TV show while Erica collect ""strong warning"" from Big Brother. Di two lovebirds enta trouble afta Biggie review one video wia two of dem flip dia fingers face di camera, something wey di organisers of di show consider as ""disrespect for Biggie authority."" Dis action from Kiddwaya come make Biggie issue am strike, im second since di show start and if im get di third one, im go chop immediate disqualification from di Big Brother house. As for Erica, Biggie cut her strong warning for her actions wit Kiddwaya. Fans bin dey fear say Biggie go disqualify Erica wey already bin dey on two strikes. No be di first time wey two of dem go break Big Brother house rules, only less dan a week ago two of dem bin enter soup unto some laws wey dem break. Afta di video review, Biggie tell di two of dem say: ""dia actions no get any other words to describe dem but na serious disrespect to Big Brother and di viewers."" Im even use di opportunity to reveal say Nengi and Prince don win VVIP trip to go Dubai for dia efforts for di Pepsi game task wey dem bin win during di week." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53968626 +entertainment Davido and Dele Adeleke: Di two cousins exchange words for social media - See di reason why "Nigerian singer, Davido dragging of im cousin, Bamidele Adeleke for social media don cause tok-tok among Nigerians. Di singer put up plenti-plenti tweets to call out im cousin, Bamidele wey dey contest with im uncle for Osun governorship election . Bamidele Adeleke dey contest with im uncle, Ademola Adeleke for di Peoples Democratic Party (PDP) party ticket ahead of di Osun 2022 governorship election. Im uncle wey be former Senator bin don first contest for governorship under PDP for 2018 but Gboyega Oyetola from All Progressive Congress (APC) defeat am. For September 2021, Senator Adeleke return from abroad and publicly declare im intention to run again for di Osun governorship election. Den on December 11, 2021, im nephew, Bamidele Adeleke among odas inside di state, pick di party nomination form and announce im interest to still contest. Later, Bamidele come also tok during one interview with Channels Television about how e feel to dey contest against im uncle. Afta dat interview, on Tuesday 18 January, Davido come put up one post with di foto of im cousin, Bamidele Adeleke and drag am for planning to contest against e uncle. ""Wonderful! Me I finish uni with 2:1. But na now cousin Dele wey struggle to even get 2:2 dey now form ""intellectual..."" Davido tok for twitter. Afta Davido tweet, im uncle, Ademola Adeleke come also respond and tweet; ""No worry nephew God got us ❤️"" Di singer also continue to put out many tweet to drag im cousin and mention how e feel say Bamidele don ""cross di line"" plus odas. E accuse im cousin say e dey pay pipo to write negative tins about am and e late mother because of im ambition but di cousin deny dis accuse. Meanwhile odas wey collect di nomination forms of PDP inside Osun state na; Akin Ogunbiyi, Sanya Omirin, Dotun Babayemi, and Fatai Akinbade. Banidele Adeleke respond back to im cousin Davido afta di dragging and say even with wetin im dey do, e go 'always still remain dear' to am. ""Dear David, For whatever dis dey worth to you, please note say I lost my mother for young age like you and I no go ever allow anyone to speak bad about her or her memory, "" Bamidele tweet. ""I no go ever write or say anything against my Auntie Vero, wey I cherish dearly. ""You be di king of social media and you definitely know say pipo dey take am upon demsef to write whatever dey believe go give dem clout."" Oga Bamidele say fans of im cousin Davido dey threaten am for on social media. ""Many of your fans come to my SM handles to threaten me and some even ask me to go and die. Na you send dem to threaten my life?. I seriously doubt am and I no believe you go do such thing."" E say no mata di politics, im no be di kind of pesin wey dey do wahala as e don always maintain decorum during provocation and go continue to do so. ""I respect your decision and choice to support Uncle Demola and dat na di beauty of democracy. ""E dey possible we fit all make our individual choices without wahala and bitterness. We fit all follow different paths and still live as one big, happy family."" Bamidele Adeleke say wetin make am put up im response for twitter na because e don bin send Davido di message privately for Whatsapp but e no deliver. Bamidele David Adeleke come from Osun State, Nigeria and dem born am for 1972, according to im profile for e website. E be cousin to popular Nigeria singer, Davido. Bamidele get OND in Accountancy from Polytechnic, Ibadan, B.SC in Management/Accounting, and MBA in General Management both from Obafemi Awolowo University Ile-Ife, Nigeria. E start im career as Banker for 1991 and don work for different Banks. Bamidele Adeleke dey contest for di Osun State governorship ticket of Peoples Democratic Party with im Uncle Ademola Adeleke." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60065587 +sports Usman vs Masvidal 2: Welterweight champion go defend im title today- Wetin you need to know about di fight "Welterweight champion, Kamaru Usman wey dem dey call 'The Nigerian Nightmare' don dey prepare to meet im challenger Jorge Masvidal for dia ogbonge fight. Usman go defend im UFC welterweight title against Masvidal for di main event of UFC 261 on Saturday inside Jacksonville, Florida. Both of dem don do dia weight successfully weighed on Friday morning for dia title clash. Usman weigh 169.5 pounds, and Masvidal hit di mark at 170. Usman don first beat Masvidal through unanimous decision for UFC 251 last July for Abu Dhabi. But Masvidal come into dat fight on just six days notice afta Usman original opponent, Gilbert Burns, test positive for coronavirus. After Kamaru beat Gilbert Burns for February, e come be 18-1 and get di longest active winning streak for UFC (13). If Masvidal fit stop dis, ego then dey open to trilogy match-up. Saturday event go be di first for US sport to get capacity crowd for indoor arena since di pandemic, and e features three title fights. Usman wey be 33 years old mix martial artist from Nigeria dey look for im fourth straight title defense and his 14th straight UFC victory. If Usman win Saturday fight, e go be in sole possession of second place in terms of di longest winning streaks for UFC history. Usman is currently tie with Khabib Nurmagomedov and Jon Jones with 13 straight victories. Only Anderson Silva get more back to back wins for UFC history (16). Fans of Jorge Masvidal say im mixed martial arts career ""no go dey complete"" until e holds one world title. Masvidal na one of UFC most popular fighters but for 18 years as a professional e neva win one world belt. Saturday rematch with welterweight champion Kamaru Usman na Masvidal second title shot and e dey fears say dis fit be e last. ""Winning dis belt na one of many things wey dey my task sheet before I close dis chapter,"" Jorge Masvida tell BBC Sport. ""I dey look at every fight as my last chance so I need to give my all, I need to push for wetin I want. If I want to be world champion then dis na di koko, I gatz to go."" ""Wen I come back for 2019, I make one checklist and do many of those things for 2019. But as far as wetin I still want to accomplish, I no go tok everything I get for di booklet because I want to keep everybody for suspense.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-56873259 +politics Sowore Revolution Now: Wetin to sabi about Omoyele Sowore, di man wey dey ginger protest across Nigeria "Nigerians go wake on Monday August 5, to know weda di protest against bad governance wey Omoyele Sowore dey ginger for , go hold after authorities arrest am last Saturday. Secret spy police - Department of State Services (DSS) don tok say dem arrest Sowore ""for threatening public safety, peaceful co-existence and social peace inside di kontri."" Since wey dem arrest Sowore, na so many ogbonge Nigerians dey condemn di move, some don say di protest must go on, but who be dis man wey dey dinger Revolution Now across Nigeria? Sowore ('Showore' as dem dey pronounce am) na Nigerian wey don spend di last 15 years to dey work to promote human rights and democracy inside Nigeria, and to stop di military rule and gbege wey foreign oil companies cause for im kontri. For 1989, Sowore follow for student 'I-no-go-gree' waka to protest di conditions wey dey inside one International Monetary Fund (IMF) loan of $120 million goment bin wan use for one Nigerian oil pipeline construction - di IMF loan conditions na to reduce di number of universities in di kontri from 28 to just five. For 1992, wen im dey University of Lagos, Sowore lead 2,000 students in protest against Nigeria corrupt leaders. Police open fire, kill seven. Sowore chop arrest ontop di mata but he no gree to back down im Aluta struggle for decent education inside im kontri. For early 2018, Sowore launch im presidential election campaign wit 'Our Mumu don do' slogan wey e say na mistake say young pipo comot hand for Nigeria mata. Di 48 year old don enta imprison eight times before now ontop dis Aluta struggle for Nigeria." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49189069 +entertainment BBNaija eviction: Ka3na, Lilo na di first Big Brother Naija lockdown housemates 2020 wey dem evict "Ka3na and Lilo don become di first two housemates to leave di Big Brother Naija season 5 lockdown house afta like two weeks wey im enta di crib. Fans of di show bin put up Lilo, Eric, Praise and Ka3na for eviction out of di 18 housemates wey bin dey up for eviction dis week. Among di 20 housemates, na only two no dey up for eviction- dat na di head of house Lucy and di pesin wey she select as assistant head of house, Prince. According to di new method of eviction from Biggie house, each housemate go later come enta di Diary room to nominate one pesin among di four housemates wey fans put up for eviction. Dis na di first time di organizers of Big Brother show dey introduce dis method for di history of di show. Brighto nominate Eric and Kat3na to leave Nengi nominate Kat3na and Praise to leave Ozo dey so emotional and reluctant to nominate and na from dia big brother gbab break for di nomination paro and di Host, Ebuka Obi Uchedu call out di names of di Housemates wey go leave. Ka3na wey im full name na Kate Jones, na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria and she describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life. While Lilo wey her real name na Boluwatife Aderogba na 23 years old dietician from Lagos, Nigeria. She be also entrepreneur and describe hersef as ""a product of God's grace"". Fans of di reality TV show dey react differently concerning di two female housemates wey comot today. While some dey thanks those wey vote for dia favourites odas don analysize di show." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53629797 +politics """Edo Election final result 2020"": Obaseki victory, Wike say ""Edo Election"" na proof say ‘Godfatherism’ dey end for Nigeria, but na true?" Di govenorship election for Edo state for southern Nigeria don come and go. And di winner na Godwin Obaseki of di Peoples Democratic Party. Few hours afta Nigeria election office, Inec declare di winner, some Nigerians enta social media to share funny memes wey show di death of wetin dem describe as 'godfatherism'. Many of di memes dey yab former govnor Adams Oshiomhole on top how e fail to beat Obaseki despite all im actions to frustrate am for second term. E win di election wit 307,955 votes across 18 local goment while im main opponent, di APC candidate, Osagie Ize Iyamu get 223,619 votes. Obaseki victory no come easy sake of di plenti political battle between him and di former govnor Adams Oshiomhole wey try everytin to make sure say im no win di election. First, e deny am to win Nigeria ruling party APC primary wey lead to oga Obaseki to port alias defect in June to di kontri main opposition PDP to contest for di 19 September election. And oga Oshiomhole also make sure e campaign against Obaseki to deny am di chance to win im second term for office. But no be Oshiomhole AKA Oshio bab only dey fight Obaseki, days to di general election, one of APC national leader, Ahmed Tinubu bin do video dey ask Edo pipo make dem no vote am. Dis two APC leaders dem bin back Obaseki during im first term election for 2016 sake of say na oga Oshiomhole bin bring am to power. Govnor Godwin Obaseki main campaign strategy and slogan na to end godfatherism (wey mean to allow one 'powerful politician to always decide who go become what, get goment appointment or win election) for Edo State - and im message really ginger di pipo wey don tire and want to stop political leaders for di state make dem stop to impose pesin wey dem like on dem. Dis na why many Nigerians dey celebrate di election victory of Godwin Obaseki as dem don create funny memes to condem godfatherism for Nigerian politics. Politics of godfatherism don tey inside Nigeria political space and many Nigerians believe say di kontri don gradually end dis practice wit di edo election but dis one na true? Anoda state wit plenti political drama between 'godfather and a sitting govnor na Akwa-Ibom State during di 2019 election. Oga Godswill Obot Akpabio bin dey in love wit former bank executive Udom Gabriel Emmanuel and make am Secretary to the State Government (SSG). E come support am to be come govnor but before im first term go finish, dem come begin to quarrel and dem later dem come draw di battle line as di 2019 election begin draw near. Akpabio bin decamp from PDP to APC and wage war against govnor Emmanuel to remove am. But despite im political clout and how e dey popular for di state, govnor Emmanuel beat APC and win di election. Many Nigerians still remember di drama wey bin happun between governor Aminu Tambuwal and Aliyu Wamakko Wey make am defect to di PDP to contest for di 2019 govnorship election. Di need to control di APC party and leadership structure make Tambuwal to fall out of favour wit oga Wamakko wey be ogbonge political leader for Sokoto state. Oga Tambuwal win di govnorship election afta dem do supplementary election. No wonder immediately dem declare Obaseki winner e say Obaseki victory resemble how im too take win for Sokoto state. Di case no dey different for Benue state wia political gbege between Govnor Samuel Ortom and George Akume bin heat up di state. Di election na really between di two political leader as each of dem try to prove who get power pass. Oga Geoarge Akume wey be former govnor of di state and di APC leader of di state na im bring Smauel Ortom for power But close to di end of im first tenure dem come di kwata as oga accuse say di former govnor no allow work sake of plenti demand. E come decamp go PDP afta e discover say oga George don make up im mind to deny am di nomination. But afta di election, and di supplementary election, dem come declare am winner. For years di PDP reign supreme for Nigeria oil rich Rivers State until one man decide to test di foundations of di party for 2015 wen e decamp go di APC. Chibuike Amaechi govern Rivers State for eight years under di umbrella of di PDP, and during dat period e rise to di level of pesin wey sabi di political game even though technically na only one election im contest and win to be govnor of di Nigerian southern state. Im porting alias defection to di APC bin look like for di first time since democracy rule for Nigeria anoda party oda dan di PDP go rule Rivers State. Already, him and e former Chief of Staff, Nyesom Wike relationship bin no sweet as e bin be before wen e be govnor, Wike imsef bin get di support of di den president of Nigeria Goodluck Jonathan. Amaechi side wit Dakuku Peterside under di umbrella of di APC to rival Wike, but in di end Wike win di 2015 govnorship election and win di 2019 election again. Even though some state govnors dem don dethrone dia godfather alias pipo wey bring dem to power, Nigerians believe say di Edo case go bring total end to godfatherism especially as di kontri prepare to elect new leaders for 2023. Although dem dey optimistic, e no clear wen dis dia dream go come through. https://www.bbc.com/pidgin/54239496 +entertainment Mercy Aigbe marry her new boo Kazim Adeoti? "Although Nigerian Nollywood actress Mercy Aigbe neva come out to officially confam say she don dey marry her new bobo, Kazim Adeoti, many of her fans and colleagues don however begin dey send congratulatory messages give her. Di movie maker recently share fotos of her and oga Kazim Adeoti during im birthday anniversary wey make pipo dey wonder if di couple don marry. Di captions she give di fotos also suggest say dem dey into serious relationship. For one of her post on top her verified Instagram page, Mercy describe hersef as Hajia Kazeem Adeoti and Agbeke Aya D'owner. She also describe di new bobo as her King, her boo, her bestie and gist partner. Her latest post on Instagram also tok about 'honeymoon'. Oga Kazeem Adeoti wey be business man bin catch di attention of many Nigerians afta di popular Nollywood actress flaunt two of dem pictures togeda on her social media page days before im birthday. She post say ""Na my boo birthday in a bit. Thank you for being amazing."" Many of her colleagues and fans like Iyabo Ojo, Chioma Akpotha, Georgina Onuoha, Laide Bakare, Linda Osifo, Omowunmi Ajiboye, Moyo Lawal and plenty odas react wit love emojis and congratulations. For April 2021, di actress bin post engagement ring wey she tok say ""I said Yes to di owner"". ""Thank you, God, of many chances "" she add for di caption of di post. But inside all di posts, Mercy Aigbe no realy come out clear to declare say she don marry her new bobo. Dis news dey come five years afta Mercy separate from her former husband, Lanre Gentry for 2017. Kazim Adeoti na man of di moment since Mercy Aigbe throw am for public eye. Di Yoruba filmmaker na movie marketer and founder of Adekaz Productions. E dey popular for Yoruba movie industry as e dey behind some of di biggest movies for di sector. E bin don marry and e get four children wit im wife Funsho. Mercy Aigbe na Nigerian actress, director and businesswoman. She dey popular for Nigerian Yoruba films. Dem born her for January 1, 1978 for Edo state southern Nigeria. She come from Benin City, di capital of Edo state. She get OND for financial studies from di Polytechnic of Ibadan. She come further her education and graduate wit degree for Theatre Arts for University of Lagos. Mercy Aigbe start her acting career wen she feature for some soap operas. Di popular TV drama series Papa Ajasco na one of am. She join Nollywood industry fully for 2016. She don act many feems and collect plenty ogbonge awards." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60125764 +sports Maradona Death : Wetin kill Maradona Diego? Football fans around di world dey mourn di death of obonge football star and one of di greatest players of all time Diego Maradona wey die for di age of 60. Di former Argentina player and World Cup winner die on Wednesday sake of heart attack for im Buenos Aires home afta im don suffer plenty years of health challenge. Im death dey come two weeks afta dem discharge am from hospital afta one successful brain surgery and plan dey to treat am for alcohol dependency. Maradona, play for clubs like Barcelona and Napoli, and na im be captain when Argentina win di 1986 World Cup, wey dem score di popular 'Hand of God' goal against England for di quarter-finals. Diego no look afta himself very well, but football sef no take care of am. For many years wen e still dey play for Argentina, Spain and Italy, dem dey always inject am wit different kain drugs sake of di pain wey dey always worry am and most time im no sabi di injection dem dey chook am. He begin take cocaine, e later become addict and begin miss training and sycophants wey surround am always dey hail am say di drugs im dey take good and na fun. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55087623 +politics Prof Ibrahim Gambari don replace Abba Kyari as President Buhari new Chief of Staff "Nigeria president Muhammadu Buhari on Wednesday reveal Professor Ibrahim Gambari as im new chief of staff. Prof. Gambari replace Oga Abba Kyari wey im name trend ontop Nigerian social media websites for almost one week afta di goment announce im death on 17 April, 2020. Secretary to di Goment of di Federation Boss Mustapha na im announce di appointment as di Federal Executive Council wan start on 13 May, 2020. Prof. Ibrahim Agboola Gambari na ogbonge scholar-diplomat wey don hold top-top positions for di joinbodi, according to informate wey United Nations put ontop dia website. Make we torchlight who di Prof be. Some of di names wey don come up before as replacement to oga Kyari na pipo like Babagana Kingibe, Adamu Adamu, Hameed Ali and even di current Kaduna governor Nasir el-Rufai. Many Nigerian wey tok wit BBC News Pidgin say dis time wey an academic and diplomat di hold di position for di country, dem hope say e go give di goment sound advice wey go move di kontri forward. Ambassador Lolo Bitrus, say oga Gambari dey very grounded for im field and as an administrator, e get di competence to serve for dat position. E say Gambari be im lecturer for university and im work wit am for di Ministry of Foreign Affairs and one quality of Gambari na say e dey level headed and e be man of substance. Ambassador Lolo further explain say im exposure for di UN go put am for di position to offer sound advice. "" If you look all di pipo wey don hold di position before, you go know say e dey more qualified because e be intellectual and competent diplomat"" Lolo tok Di president of Nigeria Foreign Relations Association, Ambassador Gani Lawal say oga Gambari na very loyal pesin and e be workaholic and e go really deliver as a chief of staff. E say Oga Gambari be foreign minister under president Muhammed Buhari den under military and dem work tegeda well well. And dat wen Nigeria former Head of Stae Ibrahim Babangida bin do coup drive away Buhari from power, e ask am make e continue as minister, e refuse di offer because of im loyalty to president Buhari. E say di kain pesin wey Gambari be, e go do di job wit human face." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52623055 +sports Man. City vs Arsenal: See where and how you fit watch di match Defending Premier League champions Manchester City go jam Arsenal dis evening for Etihad Stadium for di first match since dem suspend di league sake of coronavirus for March, 2020. Both teams go wan win di match as di two of dem get wetin dem dey fight for league. City go wan keep di title race alive while Arsenal dey eye top four position to qualify for champions league. Manchester City coach Pep Guardiola say im players no dey fully fit but say im no get any injury problems. Aymeric Laporte fit return afta im miss City past three games with hamstring issue, meanwhile Leroy Sane fit play too im don dey out since im injure im knee last August. Meanwhile Arsenal head coach Mikel Arteta say im no get any injury problem with im team. Dis match dey come too soon for Lucas Torreira and Calum Chambers wey don dey out for di Gunners for some time now sake of injury, dem still dey try to regain dia fitness. As tins be so, Guardiola City dey number two for table, 25 points behind Liverpool. While Arsenal dey siddon for number nine position with eight points behind Chelsea wey dey fourth position. Na 8:15pm Nigerian time be di kickoff for Man City vs Arsenal for Etihad stadium for Manchester. Cable television company DSTV, go show di match for Super Sports 3. https://www.bbc.com/pidgin/sport-53076421 +sports Mikel Arteta: See wetin you need to know about di new Gunners manager "Arsenal don appoint dia former player Mikel Arteta as dia new manager. Di former Gunners midfielder bin dey work with Pep Guardiola as coach for Manchester City, im join dem afta im retire as player for 2016. Im go replace Unai Emery wey Arsenal sack for early November but dem neva announce im coaching team yet. Arteta wey be 37 years win FA Cup two times for di five years wey im spend with di Gunners. ""We need to dey compete for di top trophies for di game,"" na wetin Arteta tok ""Dat one dey very clear to me, when I discuss with di [owners] Stan and Josh Kroenke and senior pipo from di club."" Arsenal dey siddon for number 10 position for Premier League table with 22 points. Arteta sign three-and-a-half year contract with Premier League club Arsenal. Di 37 year old, na former Arsenal club captain, wey play five seasons for di club, from 2011 to 2016. As player for di club im win two FA Cups titles. Before im join Arsenal as dia new manager im bin dey part of Pep Guardiola coaching staff for Manchester City. Arteta na di 20th manager wey di club go appoint inside dia 133-year history. Di former midfielder sabi speak plenty language dem, im dey speak Spanish, Basque, Catalan and English well-well. Im also dey speak French, Italian and Portuguese small too." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50869323 +politics Rotimi Akeredolu reply AGF Malami on why 'decision to ban open grazing go remain' "Southern govnors forum for Nigeria don declare say dia decision to ban open grazing ""no go change and dem go enforce am seriously"" and if AGF Malami no like am, make im come meet dem for court. Inside statement wey Ondo State govnor, Oluwarotimi Akeredolu, sign, di govnors sama reply give di Attorney General of di Federation (AGF) wey also be di Minister of Justice, Abubakar Malami. Both of dem bin compare di southern govnors decision to ban open grazing to northern govnors ban on spare part dealers for dia own states. ""E dey very unfortunate say di AGF no fit tell di difference for issues as expected of pesin wey be senior advocate."" ""Ordinarily reasonable pipo wey sabi di difference between legitimate business wey no dey cause security challenge and special like for katakata, no suppose ansa dis tok."" Tori of how herdsmen don dey allegedly worry farmers and kill unarmed civilians for many sates for Nigeria don dey go on for a while now. Di kasala don lead to di loss of lives, farmlands and properties and many pipo don lose dia homes. Oga Akeredolu add say, dem dey advice oga Malami to go court go challenge weda or not di law wey dey ban open grazing for di different states and di decision of di southern govnors to consider di interest of dia pipo dey wrong, im tok. E add say dem dey very ready to meet am for court." https://www.bbc.com/pidgin/world-57189575 +politics Adams Oshiomhole suspension from Appeal Court land as Godwin Obaseki, Philip Shaibu resign from APC while PDP dey confident for Edo election "For sure, Govnor Godwin Obaseki go join People's Democratic Party before di primary wey go happun on June 19 and 20, Chairman of Peoples Democratic Party for Edo state, Tony Aziegbemi don tell BBC Pidgin. Aziegbem say di govnor go join di party but as di PDP constitution no get automatic ticket. ""I don read di constitution of my party back to back and notin like automatic ticket for dat constitution. Na process wey you go through. So if im join us, di next tin na for im to desire our ticket, den all di procedures of di constitution go follow."" Di Edo PDP chairmo tok. ""My interest as di chairman of di party for Edo state na to make am (Obaseki) join di party first."" na so im tok. National tok tok pesin of di PDP, Kola Olagbondiyan, tell BBC say for govnor Obaseki to become part of dia party, ""di process go begin wit di Edo state chapter of di PDP den end with us for national."" Meanwhile, di Court of Appeal for Abuja don confam di suspension of Adams Oshiomole as di National Chairman of di All Progressive Congress party. di three man panel of justice wey di president of di court of appeal, Justice Monica Fongban-Mensem, say e no make sense say Oshiomhole challenge im suspension. On 4 March, FCT High Court bin accept di request of APC for Edo state to suspend Oshiomhole from office. As all dis one dey happun, govnor Godwin Obaseki deputy Philip Shaibu sef also don resign from APC. Oga Obaseki resign im membership from All Progressive Congress party on Tuesday morning of June 16 afta di party disqualify am from contesting for di party primary wey go happun on June 22. Di Edo State govnor resign from im APC party on Tuesday, days afta di party disqualify am from di 22 June party primary ahead of di 2020 govnorship election. Govnor Godwin Obaseki dey find second term for office but APC screening committee disqualify am on top alleged fake certificate. Di All Progressive Congress screen six candidate for the govnorship primaries on June 12. Out of di six, three of di candidates, Osaro Obaze, Dr Pius Odubu and Pastor Osagie Ize-Iyamu make am. Di remaining three including govnor Godwin Obaseki dey disqualified, even though University of Ibadan come out to confirm say di certificate dey authentic. As e be so, e neva clear weda Oga Obaseki go port go di Peoples Democratic Party to contest second term. Still, as di long time katakata between Obaseki and former Edo state govnor wey be APC national chairman now, Adams Oshiomole reach climax, di party dey warm up to give dia support to anoda candidate, Pastor Osagie Ize-Iyamu." https://www.bbc.com/pidgin/media-53068018 +sports Man Utd flog Liverpool 4 - 0 for pre-season match "Manchester United score three first half goals to beat Liverpool 4-0 for dia friendly pre-season match. Red Devils play di match for Bangkok, Thailand on Tuesday. Jadon Sancho, Fred, Anthony Martial and Facundo Pellistri score di goals for United. Liverpool bin hit di post twice and create good chances earlier. Reds bin force De Gea to make saves before United take di Lead. For second half di two teams make changes to dia starting line up. United bring in Charlie Savage, Tyrell Malacia, Donny van de Beek, Aaron Wan-Bissaka, Facundo Pellistri, Eric Bailly, Amad Diallo, Anthony Elanga, Alex Telles, Zidane Iqbal. While Liverpool bring in Adrian, Salah, Frauendorf, Williams, Matip, Tsimikas, Bajcetic, Clarkson, Milner, Jones, Clark, Oxlade-Chamberlain. But na Erik Ten Hag team continue to dominate di match, dem break down Liverpool defence again wit quick counter attack. Eric Bailly run from im half to pass to im teammate Amad wey find Facundo Pellistri and im shot beat Adrian di Liverpool goal keeper to make am 4-0. Dis result mean say Erik ten Hag begin im reign as Manchester United manager wit a win.\n\nMan United next pre-season friendly na against Melbourne Victory and Crystal Palace for Australia. Manchester United manager Erik ten Hag tell MUTV afta di game say: ""I dey satisfied today. Di team get great sprit and we know we just dey start. ""We bin make some mistakes for our press, we concede some chances, but we create a lot. ""We get to work hard to cut out di mistakes but of course we dey happy. ""I know say we get good players. We don start to build new team and I dey happy wit di first game. ""E go take a lot of time. I see a lot of mistakes. Liverpool bin play three teams inside dis match, wey no be dia strongest side. We no go overestimate dis result. ""But still, I see some really good things. A lot of speed and creativity up front."" Man United next pre-season friendlies na against Melbourne Victory and Crystal Palace for Australia More updates go follow later..." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cglrkvj0ne7o +entertainment Grammy awards 2021 winners: Burna Boy, Beyoncé & Wizkid, Taylor Swift, Kanye win 63rd Grammy Awards "Burna Boy don collect im first ever Grammys Best Global Music Awards for ""Twice as Tall"". For im acceptance speech, Burna Boy tell pipo make dem believe in themselves as im tok say ""Africa don land."" Dis na di first time wey Nigerian go win for dis category. Burna Boy, age 29 wey real name be Damini Ogulu, bin dey nominated last year for im African Giant album but na Angelique Kidjoe in gbab am. Wizkid name don join di list of Grammy Winners as im join Beyoncé and Blue Ivy to gbab award for di Best Music Video for Brown Skin girls. Beyoncé become di performing female artist wit di most career Grammy wins ever, totalling 28. Dis go be di first time di Nigerian super star dey gbab di award. Dis dey come as Burna Boy, wey dem born for Port Harcourt Nigeria, bin perform for di first time for di Premier Ceremony. Di Nigerian Afrobeats stars Burna Boy and Wizkid collect di awards for di Premier Ceremony wey dey come before di main di main Grammy Awards. Dis na wia dem dey give some of di awards wey dem fit no get time for, for di main awards. Di Premier Ceremony dey come about six hours before di main 63rd Grammy Awards ceremony go start. Di show wey Jhene Aiko host also feature Kanye West wey win di Best Contemporary Christian Music Album for im Jesus Is King Album. Dis dey come afta video bin comot of am wen im dey piss for inside di award plaque for September 2020. Taika Watiti also collect di award for best Soundtrack compilation for im work for di cartoon Jojo Rabbit. Billie Eilish for di song ""No Time Left To Die"" wey she follow write with her brother, Finneas Baird O'Connell. Lady Gaga and Ariana Grande win Best Pop Duo/Group Performance winner wit 'RAIN ON ME' John Legend gbab di Best R&B Album for Bigger Love Taylor Swift take home di massive Album Of The Year win for 'folklore' for di 2021 Grammys Record Of The Year winner na ""everything i wanted"" - by Billie Eilish Dua Lipa 'Future Nostalgia' win Best Pop Vocal Album for di 63rd Grammys With ""I Can't Breathe"" H.E.R takes home Song Of The Year Grammys Anderson Blacked take home Best Melodic Rap Performance at the 63rd Grammys Best Rap Song winner na ""Savage"" Megan Thee Stallion and Beyonce American rapper Megan Thee Stallion take home Best New Artist for di 2021 Grammys. Puerto Rican superstar Bad Bunny take home Best Latin Pop Or Urban Album For 'YHLQMDLG' for di 2021 Grammys Nas win Best Rap Album winner wit 'KING'S DISEASE' Justin Bieber PLUS Dan And Shay win di Best Country Duo/Group Performance winner - ""10,000 HOURS"" Dolly Parton and Zach Williams win Best Contemporary Christian Music Performance/Song winner wit -""THERE WAS JESUS"" Jazz Vocal Album Solo winner - 'SECRETS ARE THE BEST STORIES' - by Real Kurt Elling ft. Danilo Perez Best Jazz Instrumental Album winner - 'TRILOGY 2' - by Chick Corea, Mcbrides World, Brian Blade Best Large Jazz Ensemble Album winner - 'DATA LORDS' - Schneider Maria Best Latin Jazz Album winner - 'FOUR QUESTIONS' - by Arturo O'Farrill & The Afro Latin Jazz Orchestra Best Traditional R&B Performance winner - 'ANYTHING FOR YOU' - by Ledis Best R&B Song winner - ""BETTER THAN I IMAGINED"" - by Robert Glasper, H.E.R Best Progressive R&B Album winner - 'IT IS WHAT IT IS' - Ashy Daddy Best Alternative Music Album - 'Fetch the Bolt Cutters' - Fiona Apple Fiona Apple also win Best Rock Performance winner wit 'SHAMEIKA' Best Traditional Pop Vocal Album winner - 'AMERICAN STANDARD' - by James Taylor Best Metal Performance - 'BUM-RUSH' by Body Count Band Best Rock Song winner - 'STAY HIGH' Brittany Howard Best Rock Album winner - 'THE NEW ABNORMAL' - by The Strokes Best Country Solo Performance winner - 'WHEN MY AMY PRAYS' - by Vince Gill Best Country Song winner - 'CROWDED TABLE' - BrandiCarlile, , Natalie Hemby, Lori McKenna, and The Highwomen Producer Of The Year, Non-Classical winner - Na WATT pocket am Best Classical Solo Vocal Album winner - 'SMYTH: THE PRISON' EXO_Orchestra, Sarah, Dashon Burton, Blachly James Best Arrangement, Instruments And Vocals winner - 'HE WON'T HOLD YOU' - by Jacob Collier Best Pop Solo Performance winner na Harry Styles Country powerhouse Miranda Lambert wIn Best Country Album for 'Wildcard' for di 2021 Grammys. Originally set for di end of January but ultimately (and expectedly) pushed back due to di ongoing coronavirus pandemic, Sunday go mark di unveiling of di 2021 class of Grammys winners. Di 63rd edition of di annual ceremony—wey Trevor Noah of di Daily Show dey host—see Beyoncé leading di way with nine nominations, including multiple nods for ""Black Parade."" ""Black Parade,"" Beyoncé ""Colors,"" Black Pumas ""Rockstar,"" DaBaby and Roddy Ricch ""Say So,"" Doja Cat ""Everything I Wanted,"" Billie Eilish [winner] ""Don't Start Now,"" Dua Lipa ""Circles,"" Post Malone ""Savage,"" Megan Thee Stallion feat. Beyoncé Chilombo, Jhene Aiko Black Pumas (Deluxe), Black Pumas Everyday Life, Coldplay Djesse Vol. 3, Jacob Collier Women in Music Pt. III, Haim Future Nostalgia, Dua Lipa Hollywood's Bleeding, Post Malone Folklore, Taylor Swift [Winner] ""Black Parade,"" Denisia Andrews, Beyoncé, Stephen Bray, Shawn Carter, Brittany Coney, Derek James Dixie, Akil King, Kim ""Kaydence"" Krysiuk & Rickie ""Caso"" Tice (Beyoncé) ""The Box,"" Samuel Gloade & Rodrick Moore (Roddy Ricch) ""Cardigan,"" Aaron Dessner & Taylor Swift (Taylor Swift) ""Circles,"" Louis Bell, Adam Feeney, Kaan Gunesberk, Austin Post & Billy Walsh (Post Malone) ""Don't Start Now,"" Caroline Ailin, Ian Kirkpatrick, Dua Lipa & Emily Warren (Dua Lipa) ""Everything I Wanted,"" Billie Eilish O'Connell & Finneas O'Connell (Billie Eilish) ""I Can't Breathe,"" Dernst Emile II, H.E.R. & Tiara Thomas (H.E.R.) [Winner] ""If the World Was Ending,"" Julia Michaels & JP Saxe (JP Saxe & Julia Michaels) Ingrid Andress Phoebe Bridgers Chika Noah Cyrus D Smoke Doja Cat Kaytranada Megan Thee Stallion [Winner] Changes, Justin Bieber Chromatica, Lady Gaga Future Nostalgia, Dua Lipa [Winner] Fine Line, Harry Styles Folklore, Taylor Swift ""Lightning and Thunder,"" Jhené Aiko Featuring John Legend ""Black Parade,"" Beyoncé [Winner] ""All I Need,"" Jacob Collier Feat. Mahalia & Ty Dolla $ign ""Goat Head,"" Brittany Howard ""See Me,"" Emily King ""The Bigger Picture,"" Dominique Jones, Noah Pettigrew & Rai'shaun Williams (Lil Baby) ""The Box,"" Samuel Gloade & Rodrick Moore (Roddy Ricch) ""Laugh Now, Cry Later,"" Durk Banks, Rogét Chahayed, Aubrey Graham, Daveon Jackson, Ron LaTour & Ryan Martinez (Drake feat. Lil Durk) ""Rockstar,"" Jonathan Lyndale Kirk, Ross Joseph Portaro IV & Rodrick Moore (DaBaby feat. Roddy Ricch) ""Savage,"" Beyoncé, Shawn Carter, Brittany Hazzard, Derrick Milano, Terius Nash, Megan Pete, Bobby Session Jr., Jordan Kyle Lanier Thorpe & Anthony White (Megan Thee Stallion feat. Beyoncé) [Winner] ""Yummy,"" Justin Bieber ""Say So,"" Doja Cat ""Everything I Wanted,"" Billie Eilish ""Don't Start Now,"" Dua Lipa ""Watermelon Sugar,"" Harry Styles [Winner] ""Cardigan,"" Taylor Swift ""Rockstar,"" DaBaby feat. Roddy Ricch ""Laugh Now, Cry Later,"" Drake feat. Lil Durk ""Lockdown,"" Anderson .Paak [Winner] ""The Box,"" Roddy Ricch ""HIGHEST IN THE ROOM,"" Travis Scott YHLQMDLG, Bad Bunny [Winner] Por Primera Vez, Camilo Mesa Para Dos, Kany García Pausa, Ricky Martin 3:33, Debi Nova Lady Like, Ingrid Andress Your Life is a Record, Brandy Clark Wildcard, Miranda Lambert [Winner] Nightfall, Little Big Town Never Will, Ashley McBryde ""Bluebird,"" Luke Dick, Natalie Hemby & Miranda Lambert (Miranda Lambert) ""The Bones,"" Maren Morris, Jimmy Robbins & Laura Veltz (Maren Morris) ""Crowded Table,"" Brandi Carlile, Natalie Hemby & Lori McKenna (The Highwomen) [Winner] ""More Hearts Than Mine,"" Ingrid Andress, Sam Ellis & Derrick Southerland (Ingrid Andress) ""Some People Do,"" Jesse Frasure, Shane McAnally, Matthew Ramsey & Thomas Rhett, songwriters (Old Dominion) ""All Night,"" Brothers Osbourne ""10,000 Hours,"" Dan + Shay & Justin Bieber [Winner] ""Ocean,"" Lady A ""Sugar Coat,"" Little Big Town ""Some People Do,"" Old Dominion A Hero's Death, Fontaines D.C. Kiwanuka, Michael Kiwanuka Daylight, Grace Potter Sound & Fury, Sturgill Simpson The New Abnormal, The Strokes [Winner] ""Kyoto,"" Phoebe Bridgers, Morgan Nagler, and Mashall Vore (Phoebe Bridgers) ""Lost In Yesterday,"" Kevin Parker (Tame Impala) ""Not,"" Adrianne Lenker (Big Thief) ""Shameika,"" Fiona Apple (Fiona Apple) ""Stay High, Brittany Howard (Brittany Howard) [Winner] ""Shameika,"" Fiona Apple[Winner] ""Not,"" Big Thief ""Kyoto,"" Phoebe Bridgers ""The Steps,"" Haim ""Stay High,"" Brittany Howard ""Daylight,"" Grace Potter Black Habits, D Smoke Alfredo, Freddie Gibbs & The Alchemist A Written Testimony, Jay Electronica King's Disease, Nas [Winner] The Allegory, Royce Da 5'9"" ""Deep Reverence,"" Big Sean feat. Nipsey Hustle ""Bop,"" DaBaby ""What's Poppin,"" Jack Harlow ""The Bigger Picture,"" Lil Baby ""Savage,"" Megan Thee Stallion feat. Beyoncé [Winner] ""Dior,"" Pop Smoke ""Un Día (One Day),"" J. Balvin, Dua Lipa, Bad Bunny, Tainy ""Intentions,"" Justin Bieber and Quavo ""Dynamite,"" BTS ""Rain on Me,"" Lady Gaga and Ariana Grande [Winner] ""Exile,"" Taylor Swift and Bon Iver Happy 2 Be Here, Any Clemons Take Time, Giveon To Feel Loved, Luke James Bigger Love, John Legend [Winner] All Rise, Gregory Porter Chilombo, Jhene Aiko Ungodly Hour, Chloe X Halle Free Nationals, Free Nationals F*** Yo Feelings, Robert Glasper It Is What It Is, Thundercat [Winner] ""Better Than I Imagine,"" Robert Glasper, Meshell Ndegeocello & Gabriella Wilson (Robert Glasper Feat. H.E.R and Meshell Ndegeocello) [Winner] ""Black Parade,"" Denisia Andrews, Beyoncé, Stephen Bray, Shawn Carter, Brittany Coney, Derek James Dixie, Akil King, Kim ""Kaydence"" Krysiuk & Rickie ""Caso"" Tice (Beyoncé) ""Collide,"" Sam Barsh, Stacey Barthe, Sonyae Elise, Olu Fann, Akil King, Josh Lopez, Kaveh Rastegar & Benedetto Rotondi (Tiana & EARTHGANG) ""Do It,"" Chloe Bailey, Halle Bailey, Anton Kuhl, Victoria Monét, Scott Storch & Vincent Van Den Ende (Chloe X Halle) ""Slow Down,"" Nasri Atweh, Badriia Bourelly, Skip Marley, Ryan Williamson & Gabriella Wilson (Skip Marley & H.E.R.) ""Sit On Down,"" The Baylor Project Featuring Jean Baylor & Marcus Baylor ""Wonder What She Thinks of Me,"" Chloe X Halle ""Let Me Go,"" Mykal Kilgore ""Anything For You,"" Ledisi [Winner] ""Distance,"" Yebba Hyperspace, Beck Fetch the Bolt Cutters, Fiona Apple [Winner] Punisher, Phoebe Bridgers Jaime, Brittany Howard The Slow Rush, Tame Impala ""Brown Skin Girl,"" Beyoncé [Winner] ""Life Is Good,"" Future Feat. Drake ""Lockdown,"" Anderson .Paak ""Adore You,"" Harry Styles ""Goliath,"" Woodkid Run To The Water, Cody Carnes All Of My Best Friends, Hillsong Young & Free Holy Water, We The Kingdom Citizen Of Heaven, Tauren Wells Jesus Is King, Kanye West [Winner] ""Beautiful Ghosts"" [From Cats], Andrew Lloyd Webber & Taylor Swift (Taylor Swift) ""Carried Me With You"" [From Onward], Brandi Carlile, Phil Hanseroth & Tim Hanseroth (Brandi Carlile) ""Into The Unknown"" [From Frozen 2], Kristen Anderson-Lopez & Robert Lopez (Idina Menzel & AURORA) ""No Time To Die"" [From No Time To Die], Billie Eilish O'Connell & Finneas Baird O'Connell (Billie Eilish) [Winner] ""Stand Up"" [From Harriett], Joshuah Brian Campbell & Cynthia Erivo (Cynthia Erivo) Ad Astra, Max Richter Becoming, Kamasi Washington Joker, Hildur Guðnadóttir 1917, Thomas Newman Star Wars: The Rise of Skywalker, John Williams A Beautiful Day in the Neighborhood, Various Artists Bill & Ted Face the Music, Various Artists Eurovision Song Contest: The Story of Fire Saga, Various Artists Frozen 2, Various Artists JoJo Rabbit, Various Artists [Winner] Beastie Boys Story, Beastie Boys, Spike Jonze Black Is King, Beyoncé We Are Freestyle Love Supreme, Freestyle Love Supreme Linda Ronstadt: The Sound of My Voice, Linda Ronstadt [Winner] That Lil Ol' Band From Texas, ZZ Top Amelie, Audrey Brisson, Chris Jared, Caolan McCarthy & Jez Unwin, principal soloists; Michael Fentiman, Sean Patrick Flahaven, Barnaby Race & Nathan Tysen, producers; Nathan Tysen, lyricist; Daniel Messe, composer & lyricist (Original London Cast) American Utopia on Broadway, David Byrne Jagged Little Pill, Kathryn Gallagher, Celia Rose Gooding, Lauren Patten & Elizabeth Stanley, principal soloists; Neal Avron, Pete Ganbarg, Tom Kitt, Michael Parker, Craig Rosen & Vivek J. Tiwary, producers (Glen Ballard & Alanis Morissette, lyricists) (Original Broadway Cast) [Winner] Little Shop of Horrors, Tammy Blanchard, Jonathan Groff & Tom Alan Robbins, principal soloists; Will Van Dyke, Michael Mayer, Alan Menken & Frank Wolf, producers (Alan Menken, composer; Howard Ashman, lyricist) (The New Off-Broadway Cast) Prince of Egypt, Christine Allado, Luke Brady, Alexia Khadime & Liam Tamne, principal soloists; Dominick Amendum & Stephen Schwartz, producers; Stephen Schwartz, composer & lyricist (Original Cast) Soft Power, Francis Jue, Austin Ku, Alyse Alan Louis & Conrad Ricamora, principal soloists; Matt Stine, producer; David Henry Hwang, lyricist; Jeanine Tesori, composer & lyricist (Original Cast) Black Mitzvah, Tiffany Haddish [Winner] I Love Everything, Patton Oswalt The Pale Tourist, Jim Gaffigan Paper Tiger, Bill Burr 23 Hours to Kill, Jerry Seinfeld Acid for the Children: A Memoir, Flea Alex Trebek - The Answer is…, Ken Jennings Blowout: Corrupted Democracy, Rogue State Russia, and the Richest, Most Destructive Industry on Earth, Rachel Maddow [Winner] Catch and Kill, Ronan Farrow Charlotte's Web (E.B. White), Meryl Streep (& Full cast) Fu Chronicles, Antibalas Twice As Tall, Burna Boy [Winner] Agora, Bebel Gilberto Love Letters, Anoushka Shankar Amadjar, Tinariwen ""On My Mind,"" Diplo & Sidepiece ""My High,"" Disclosure Feat. Aminé & Slowthai ""The Difference,"" Flume feat. Toro y Moi ""Both Of Us,"" Jayda D ""10%,"" Kaytranada feat. Kali Uchis [Winner] Kick I, Arca Planet's Mad, Baauer Energy, Disclosure Bubba, Kaytranada [Winner] Good Faith, Madeon Axiom, Christian Scott Atunde Adjuah Chronology Of A Dream: Live at Village Vanguard, Jon Baptiste Take The Stars, Black Violin Americana, Grégoire Maret, Romain Collin & Bill Frisell Live At The Royal Albert Hall, Snarky Puppy [Winner] ""Baby Jack,"" Arturo O'Farrill, (Arturo O'Farrill & The Afro Latin Jazz Orchestra) ""Be Water II,"" Christian Sands (Christian Sands) ""Plumfield,"" Alexandre Desplat (Alexandre Desplat) ""Sputnik,"" Maria Schneider (Maria Schneider) [Winner] ""Strata,"" Remy Le Boeuf (Remy Le Boeuf's Assembly Of Shadows Featuring Anna Webber & Eric Miller) ""Bathroom Dance,"" Hildur Guðnadóttir (Hildur Guðnadóttir) ""Donna Lee,"" John Beasley (John Beasley) [Winner] ""Honeymooners,"" Remy Le Boeuf (Remy Le Boeuf's Assembly Of Shadows) ""Life Every Voice and Sing,"" Alvin Chea & Jarrett Johnson (Jarrett Johnson Featuring Alvin Chea) ""Uranus: The Magician,"" Jeremy Levy (Jeremy Levy Jazz Orchestra) Songs from the Bardo, Laurie Anderson, Tenzin Choegyal & Jesse Paris Smith Periphery, Priya Darshini Form//Less, Superposition More Guitar Stories, Jim ""Kimo"" West [Winner] Meditations, Cory Wong & Jon Batiste ""Wonderful Is Your Name,"" Melvin Crispell III ""Release (Live),"" David Frazier (Ricky Dillard Featuring Tiff Joy) ""Come Together,"" Rodney ""Darkchild"" Lashawn Daniels, Rodney Jerkins, Lecrae Moore & Jazz Nixon (Jerkins Presents: The Good News) ""Won't Let Go,"" Travis Greene ""Movin' On,"" Darryl L. Howell, Jonathan Caleb McReynolds, Kortney Jamaal Pollard & Terrell Demetrius Wilson (Jonathan McReynolds & Mali Music) [Winner] 2econd Wind: Ready, Anthony Brown & group therAPy My Tribute, Myron Butler Choirmaster, Ricky Dillard Gospel According To PJ, PJ Morton [Winner] Kierra, Kierra Sheard Best Roots Gospel Album Beautiful Day, Mark Bishop 20/20, The Crabb Family What Christmas Really Means, The Erwins Celebrating Fisk! (The 150th Anniversary Album), Fisk Jubilee Singers [Winner] Something Beautiful, Ernie Haase & Signature Sound Everyday Life, Pilar Zeta (Coldplay) Funeral, Kyle Goen (Lil Wayne) Healer, Julian Gross & Hannah Hooper (Grouplove) On Circles, Jordan Butcher (Caspian) Vols. 11 & 12, Doug Cunningham & Jason Noto (Desert Sessions) [Winner] Flaming Pie (Collector's Edition), Linn Wie Andersen, Simon Earith, Paul McCartney & James Musgrave (Paul McCartney) Giants Stadium 1987, 1989, 1991, Lisa Glines & Doran Tyson (Grateful Dead) Mode, Jeff Schulz (Depeche Mode) Ode to Joy, Lawrence Azerrad & Jeff Tweedy (Wilco)[Winner] The Story of Ghostly International, Michael Cina & Molly Smith (Various Artists) At the Minstrel Show: Minstrel Routines from the Studio, 1894-1926, Tim Brooks (Various Artists) The Bakersfield Sound: Country Music Capital of the West, 1940-1974, Scott B. Bomar (Various Artists) Dead Man's Pop, Bob Mehr (The Replacements) [Winner] The Missing Link: How Gus Haenschen Got Us from Joplin to Jazz and Shaped the Music Business, Colin Hancock (Various Artists) Out of a Clear Blue Sky, David Sager (Nat Brusiloff) Celebrated, 1895-1896, Meagan Hennessey & Richard Martin (Unique Quartette) Hittin' The Ramp, The Early Years (1936 - 1943), Zev Feldman, Will Friedwald & George Klabin, Matthew Lutthans (Nat King Cole) It's Such a Good Feeling: The Best of Mister Rogers, Lee Lodyga & Cheryl Pawelski, Michael Graves (Mister Rogers) [Winner] 1999 Super Deluxe Edition, Michael Howe, Bernie Grundman (Prince) Souvenir, Carolyn Agger, Miles Showell (Orchestral Manoeuvres In The Dark) Throw Down Your Heart: The Complete Africa Sessions, Béla Fleck, Richard Dodd (Béla Fleck) Black Hole Rainbow (Devon Gilfillian) Expectations (Katie Pruitt) Hyperspace (Beck)[Winner] Jaime (Brittany Howard) 25 Trips (Sierra Hull) ""Do You Ever (RAC Mix),"" RAC (Phil Good) ""Imaginary Friends (Morgan Page Remix),"" Deadmau5 (Morgan Page) ""Praying for You (Louie Vega Main Remix),"" Jasper Street Co. (Louie Vega) ""Roses (Imanbek Remix),"" Saint JHN (Imanbek Zeikenov) [Winner] ""Young & Alive (Bazzi vs. Haywire Remix),"" Bazzi (Haywyre) Danielpour: The Passion of Yeshua Gershwin: Porgy and Bess Hynes: Fields Ives: Complete Symphonies Shostakovich: Symphony No. 13, 'Babi Yar'[Winner]  Blanton Alspaugh David Frost[Winner] Jesse Lewis Dmitriy Lipay Elaine Martone Aura, Bajofondo Monstruo, Cami Sobrevolando, Cultura Profética La Conquista Del Espacio, Fito Paez[Winner] Miss Colombia, Lido Pimienta Hecho En México, Alejandro Fernández La Serenata, Lupita Infante Un Canto Por Mexico, Vol.1, Natalia Lafourcade [Winner] Bailando Sones y Huapangos Con el Mariachi Sol de Mexica de Jose Hernandez, Mariachi Sol De Mexico De Jose Hernandez AYAYAY!, Christian Nodal Mi Tumbao, José Alberto ""El Ruiseñor"" Infinito, Edwin Bonilla Sigo Cantando Al Amor (Deluxe), Jorge Celedon & Sergio Luis 40, Grupo Niche [Winner] Memorias de Navidad, Víctor Manuelle ""Aspects of America - Pulitzer Edition,"" Carlos Kalmar (Oregon Symphony) ""Concurrence,"" Daníel Bjarnason (Iceland Symphony Orchestra) ""Copland: Symphony No. 3,"" Michael Tilson Thomas (San Francisco Symphony) ""Ives: Complete Symphonies,"" Gustavo Dudamel (Los Angeles Philharmonic) [Winner] ""Lutoslawski: Symphonies Nos. 2 & 3,"" Hannu Lintu (Finnish Radio Symphony Orchestra) ""Dello Joio: The Trial at Rouen,"" Gil Rose, Heather Buck & Stephen Powell (Boston Modern Orchestra Project; Odyssey Opera Chorus) ""Floyd C., Prince of Players,"" William Boggs, Keith Phares & Kate Royal, Blanton Alspaugh (Milwaukee Symphony Orchestra; Florentine Opera Chorus) ""Gershwin: Porgy and Bess,"" David Robertson, Angel Blue & Eric Owens, David Frost (The Metropolitan Opera Orchestra; The Metropolitan Opera Chorus) [Winner] ""Handel: Agrippina,"" Maxim Emelyanychev, Joyce DiDonato, Daniel Zalay (Il Pomo D'Oro) ""Zemlinksy: Der Zwerg,"" Donald Runnicles, David Butt Philip & Elena Tsallagova, Peter Ghirardini & Erwin Stürzer (Orchestra Of The Deutsche Oper Berlin; Chorus Of The Deutsche Oper Berlin) ""Carthage,"" Donald Nally (The Crossing) ""Danielpour: The Passion of Yeshua,"" JoAnn Falletta, James K. Bass & Adam Luebke (James K. Bass, J'Nai Bridges, Timothy Fallon, Kenneth Overton, Hila Plitmann & Matthew Worth; Buffalo Philharmonic Orchestra; Buffalo Philharmonic Chorus & UCLA Chamber Singers) [Winner] ""Kastalsky: Requiem,"" Leonard Slatkin, Charles Bruffy, Steven Fox & Benedict Sheehan (Joseph Charles Beutel & Anna Dennis; Orchestra Of St. Luke's; Cathedral Choral Society, The Clarion Choir, Kansas City Chorale & The Saint Tikhon Choir) ""Moravec: Sanctuary Road,"" Kent Tritle (Joshua Blue, Raehann Bryce-Davis, Dashon Burton, Malcolm J. Merriweather & Laquita Mitchell; Oratorio Society Of New York Orchestra; Oratorio Society Of New York Chorus) ""Once Upon A Time,"" Matthew Guard (Sarah Walker; Skylark Vocal Ensemble) ""Contemporary Voices,"" Pacifica Quartet [Winner] ""Healing Modes,"" Brooklyn Rider ""Hearne, T.: Place,"" Ted Hearne, Steven Bradshaw, Sophia Byrd, Josephine Lee, Isaiah Robinson, Sol Ruiz, Ayanna Woods & Place Orchestra ""Hynes: Fields,"" Devonté Hynes & Third Coast Percussion ""The Schumann Quartets,"" Dover Quartet Adès; Concerto for Piano and Orchestra, Kirill Gerstein Beethoven: Complete Piano Sonatas, Igor Levit Bohemian Tales, Augustin Hadelich Destination Rachmaninov - Arrival, Daniil Trifonov Theofanidis: Concerto for Viola and Chamber Orchestra, Richard O'Neill [Winner] Adès Conduct Adès, Mark Stone & Christianne Stotijn; Thomas Adès, Nick Squire Saariaho: Graal Theatre; Circle Map' Neiges; Vers Toi Es Si Loin, Clément Mao-Takacs, Hans Kipfer Serebrier: Symphonic Bach Variations; Laments and Hallelujahs; Flute Concerto, José Serebrier, Jens Braun Thomas, M.T.: From the Diary of Anne Frank & Meditations on Rilke, Isabel Leonard, Michael Tilson Thomas, Jack Vad [Winner] Woolf, L.P.: Fire and Flood, Matt Haimovitz, Julian Wachner, Blanton Alspaugh Adès: Concerto for Piano and Orchestra, Thomas Adès (Kirill Gerstein, Thomas Adès & Boston Symphony Orchestra) Danielpour: The Passion of Yeshua, Richard Danielpour (JoAnn Falletta, James K. Bass, Adam Luebke, UCLA Chamber Singers, Buffalo Philharmonic Orchestra & Buffalo Philharmonic Chorus) Floyd, C.: Prince of Players, Carlisle Floyd (William Boggs, Kate Royal, Keith Phares, Florentine Opera Chorus & Milwaukee Symphony Orchestra) Hearne, T.: Place, Ted Hearne (Ted Hearne, Steven Bradshaw, Sophia Byrd, Josephine Lee, Isaiah Robinson, Sol Ruiz, Ayanna Woods & Place Orchestra) Rouse: Symphony No. 5, Christopher Rouse (Giancarlo Guerrero & Nashville Symphony) [Winner] ""Colors,"" Black Pumas ""Deep In Love,"" Bonny Light Horseman ""Short and Sweet,"" Brittany Howard ""I'll Be Gone,"" Norah Jones & Mavis Staples ""I Remember Everything,"" John Prine [Winner] ""Cabin,"" Laura Rogers & Lydia Rogers (The Secret Sisters) ""Ceiling To The Floor,"" Sierra Hull & Kai Welch (Sierra Hull) ""Hometown,"" Sarah Jarosz ""I Remember Everything,"" Pat McLaughlin & John Prine (John Prine) [Winner] ""Man Without a Soul,"" Tom Overby & Lucinda Williams (Lucinda Williams) Old Flowers, Courtney Marie Andrews Terms Of Surrender, Hiss Golden Messenger World On The Ground, Sarah Jarosz [Winner] El Dorado, Marcus King Good Souls Better Angels, Lucinda Williams Man On Fire, Danny Barnes To Live In Two Worlds, Vol. 1, Thomm Jutz North Carolina Songbook, Steep Canyon Rangers Home, Billy Strings [Winner] The John Hartford Fiddle Tune Project, Vol. 1, Various Artists All My Dues Are Paid, Frank Bey You Make Me Feel, Don Bryant That's What I Heard, Robert Cray Band Cypress Grove, Jimmy ""Duck"" Holmes Rawer Than Raw, Bobby Rush [Winner] Have You Lost Your Mind Yet?, Fantastic Negrito [Winner] Live At The Paramount, Ruthie Foster Big Band The Juice, G. Love Blackbirds, Bettye LaVette Up And Rolling, North Mississippi Allstars Bonny Light Horseman, Bonny Light Horseman Thanks for the Dance, Leonard Cohen Song For Our Daughter, Laura Marling Saturn Return, The Secret Sisters All The Good Times, Gillian Welch & David Rawlings [Winner] My Relatives ""Nikso Kowaiks,"" Black Lodge Singers Cameron Dupuy and the Cajun Troubadors, Cameron Dupuy And The Cajun Troubadours Lovely Sunrise, Nā Wai ʽEhā Atmosphere, New Orleans Nightcrawlers [Winner] A Tribute To Al Bernard, Sweet Cecilia Upside Down 2020, Buju Banton Higher Place, Skip Marley It All Comes Back To Love, Maxi Priest Got To Be Tough, Toots & The Maytals [Winner] One World, The Wailers All The Ladies, Joanie Leeds [Winner] Be a Pain: An Album for Young (and Old) Leaders, Alastair Moock And Friends I'm An Optimist, Dog On Fleas Songs For Singin', The Okee Dokee Brothers Wild Life, Justin Roberts ""Guinevere,"" Christian Scott Atunde Adjuah, track from: Axiom ""Pachamama,"" Regina Carter, track from: Ona (Thana Alexa) ""Celia,"" Gerald Clayton ""All Blues"" Chick Corea, track from: Trilogy 2 (Chick Corea, Christian McBride & Brian Blade) [Winner] ""Moe Honk,"" Joshua Redman, track from: RoundAgain (Redman Mehldau McBride Blade) Ona, Thana Alexa Secrets Are The Best Stories, Kurt Elling Feat. Danilo Pérez [Winner] Modern Ancestors, Carmen Lundy Holy Room: Live at Alte Oper, Somi With Frankfurt Radio Big Band What's The Hurry, Kenny Wahsington on the tender spot of every calloused moment, Ambrose Akinmusire Waiting Game, Terri Lyne Carrington And Social Science Happening: Live at the Village Vanguard, Gerald Clayton Trilogy 2, Chick Corea, Christian McBride & Brian Blade [Winner] Roundagain, Redman Mehldau McBride Blade Dialogues on Race, Gregg August MONK'estra Plays John Beasley, John Beasley The Intangible Between, Orrin Evans And The Captain Black Big Band Songs You Like A Lot, John Hollenbeck With Theo Bleckmann, Kate McGarry, Gary Versace And The Frankfurt Radio Big Band Data Lords, Maria Schneider Orchestra [Winner] Tradiciones, Afro-Peruvian Jazz Orchestra Four Questions, Arturo O'Farrill & The Afro Latin Jazz Orchestra [Winner] City of Dreams, Chico Pinheiro Viento y Tiempo: Live at Blue Note Tokyo, Gonzalo Rubalcaba & Aymée Nuviola Trane's Delight, Poncho Sanchez Blue Umbrella, Burt Bacharach and Daniel Tashain True Love: A Celebration of Cole Porter, Harry Connick Jr. American Standard, James Taylor [Winner] Unfollow the Rules, Rufus Wainwright Judy, Renee Zellweger ""Bum-Rush,"" Body Count [Winner] ""Underneath,"" Code Orange ""The In-Between,"" In This Moment ""Bloodmoney,"" Poppy ""Executioner's Tax (Swing of the Axe) — Live,"" Power Trip ""Stick That In Your Country Song,"" Eric Church ""Who You Thought I Was,"" Brandy Clark ""When My Amy Prays,"" Vince Gill [Winner] ""Black Like Me,"" Mickey Guyton ""Bluebird,"" Miranda Lambert Jack Antonoff Dan Auerbach Dave Cobb Flying Lotus Andrew Watt [Winner] ""Asas Fechadas,"" John Beasley & Maria Mendes (Maria Mendes Featuring John Beasley & Orkest Metropole) ""Desert Song,"" Erin Bentlage, Sara Gazarek, Johnaye Kendrick & Amanda Taylor (Säje) ""From This Place,"" Alan Broadbent & Pat Metheny (Pat Metheny Featuring Meshell Ndegeocello) ""He Won't Hold You,"" Jacob Collier (Jacob Collier Featuring Rapsody) [Winner] ""Slow Burn,"" Talia Billig, Nic Hard & Becca Stevens (Becca Stevens Feat. Jacob Collier, Mark Lettieri, Justin Stanton, Jordan Perlson, Nic Hard, Keita Ogawa, Marcelo Woloski & Nate Werth) ""The Blessing (Live),"" Chris Brown, Cody Carnes, Kari Jobe Carnes & Steven Furtick (Kari Jobe, Cody Carnes & Elevation Worship) ""Sunday Morning,"" Denisia Andrews, Jones Terrence Antonio, Saint Bodhi, Brittany Coney, Kirk Franklin, Lasanna Harris, Shama Joseph, Stuart Lowery, Lecrae Moore & Nathanael Saint-Fleur (Lecrae Featuring Kirk Franklin) ""Holy Water,"" Andrew Bergthold, Ed Cash, Franni Cash, Martin Cash & Scott Cash (We The Kingdom) ""Famous For (I Believe),"" Chuck Butler, Krissy Nordhoff, Jordan Sapp, Alexis Slifer & Tauren Wells (Tauren Wells Featuring Jenn Johnson) ""There Was Jesus,"" Casey Beathard, Jonathan Smith & Zach Williams (Zach Williams & Dolly Parton) [Winner] American Composers at Play, William Bolcom, Ricky Ian Gordon, Lori Laitman, John Musto, Stephen Powell Clairières, Lili & Nadia Boulanger, Nicholas Phan Farinelli, Cecilia Bartoli A Lad's Love, Biran Giebler Smyth: The Prison, Sarah Brailey & Dashon Burton [Winner]" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56395338 +health Coronavirus cases in Lagos: Sanwo-Olu don pass order say 'Lagosians must use face mask from now on or face di law' Lagos state goment don give order make evribodi wey dey enta public space for di state wia face mask or face di law. Govnor Babajide Sanwo-Olu wey give di order on Saturday add say goment don make arrangement for mass production of face mask. Di Lagos State goment bin pass one new law wey give di govnor power to pass order and make declaration wey go helep di fight against di new Coronavirus. Di govnor beg private organizations to patronize local face mask producers and share to dia workers. E say face mask don become business wey small and big business suppose take advantage of. Lagos don get over 600 confam cases of Covid19 and local transmission dey on di increase according to di govnor. Na at least 20 million pipo dey live inside Lagos wey be di bizness capital of Nigeria. Since 30 March, 2020, na only Lagos and Ogun States for south west region and Abuja, di political capital of Nigeria be di places wey Presido Muhammadu Buhari order lockdown for, sake of di Coronavirus outbreak. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52042724 +sports Gabon 1 - 1 Ghana Afcon 2021: Thomas Partey through pass make André Ayew score, game end for draw A last minute goal make Ghana lose three points for dia match Gabon. Jim Allevinah 88 minutes goal help Gabon equalise for di last minute of di game - na Guélor Kanga give am di pass. Di black stars bin dey lead wit Andrew Ayew first half goal. Dem continue to press for second half but Gabon show a lot of promise. Gabon continue to pree even without dia captain Pierre-Emerick Aubameyang wey no make di squad. Dis na because di former Arsenal captain dey suffer some complication as e recover from Covid. As di match end like dis Gabon dey occupy di second position for Group C wit four points. Already, Morocco don become di first kontri to qualify go di second round of di tournament for Group C, afta dem beat Comoros earlier on Friday. Goals from Selim Amallah and Zakaria Aboukhal help Morocco secure di 2-0 victory. Di Black Stars bin lose dia first match 1-0 to Morocco - Ghana dey for third position wit just one point. A win for Gabon go mean say Ghana chances for di tournament inside go dey slim as Gabon win dia first game against Comoros. Game don start and na still Gabon 0, Ghana 1. 46mins: Alexander Djiku concede corner for Gabon. 46mins: Junior Assoumou miss goal attempt afta e use head from centre of di box sake of di corner. 48mins: Dénis Bouanga win free kick for di defensive half. 48mins: Offside by Johann Obiang of Gabon. 50mins: Aaron Salem Boupendza win free kick for di defensive half. 51mins: Foul by Kamaldeen Sulemana of Ghana make Louis Ameka win free kick for di defensive half. 53mins: Substitution for Gabon. Jim Allevinah replace Dénis Bouanga. 54mins: Junior Assoumou conceded corner. 56mins: Ghana defender block shot from Johann Obiang from di left side of di box. 57mins: Anthony Oyono chop yellow card for bad foul on Kamaldeen Sulemana. 59mins: Daniel-Kofi Kyereh chop yellow card for bad foul on Guélor Kanga. 61mins: Substitution for Ghana. Edmund Addo replace Kamaldeen Sulemana. 62mins: Gabon win corner wey Abdul Rahman Baba. concede. 64mins: Guélor Kanga miss attempt afta e use right leg shoot from more dan 35 yards. 65mins: Substitution for Ghana. Joseph Paintsil replace Iddrisu Baba sake of injury. 67mins: Thomas Partey win free kick for di defensive half. 67mins: Substitution for Gabon. Ulrick Eneme-Ella replace Serge-Junior Martinsson-Ngouali. 70mins:Foul by Aaron Salem Boupendza 71mins: Keeper save attempt by Guélor Kanga wey play shot from more dan 35 yards. 73mins: Edmund Addo win free kick for di defensive half. 75mins: Gabon defender black Joseph Paintsil shot from outside di box blocked. 76mins: Substitution for Gabon. Alex Moucketou-Moussounda replace Louis Ameka. 79mins: André Ayew win free kick for di attacking half. 80mins: Jordan Ayew shoot off target from a direct free kick. 81mins: Joseph Wollacott chop yellow card. 83mins: Thomas Partey win free kick for di defensive half. 86mins: Foul by André Biyogo Poko 88mins: Goal! Gabon 1, Ghana 1. Na Jim Allevinah score for Gabon. 90mins: Joseph Paintsil win free kick. 90mins+2: Thomas Partey header from di centre of di box from corner. Second Half don end, Gabon 1, Ghana 1. Dey refresh di page for Live updates of di match 1min: Na Ghana kick di first ball 5mins: Guélor Kanga take free kick from di left and cross inside di box. 10mins: Plenty activity dey happen for di midfield. Di two team no fit go front. 14mins: André Ayew go di right side of di box and cross enta di oda side. Amonome deflect di ball away from di goal. 19mins: Goal! Andre Ayew score wit long range shot from outside box 18 20mins: Bouanga take corner kick too hard, and di ball go over di line. Goal kick for Ghana. 24mins: Autchanga receive pass on di left, drives di ball up go middle Yiadom block di shot. 25mins: Yellow card for Manga, Gabon centre-back as e kick André Ayew. 28mins: André Ayew win free kick for di defensive half. 29mins: Guélor Kanga pass give Obiang on di left side of di box but Amartey head am comot. 32mins: Jordan Ayew wins free kick for di defensive half. 34mins: Alexander Djiku win free kick for di defensive half. 36mins: Thomas Partey chop yellow card for bad foul. 38mins: Gabon goal keeper save André Ayew right. 39mins: Hand ball by André Ayew. 42mins: Guélor Kanga miss goal afta e use right leg hit shot from more dan 35 yards. 43mins: Gabon keeper save Dénis Bouanga shot from long range. 45mins: Dénis Bouanga of Gabon win free kick for di defensive half. First Half don finish and na Gabon 0, Ghana 1. Senegal and Guinea don retain dia first and second position for group B for di ongoing African cup of Nations (Afcon) 2021 for Cameroon. Saido Mane and Naby Keita wey dey both play for Liverpool no shine for di match. Di two kontris dey four points each afta dia match end nil-nil dis afternoon. Senegal and Guinea move closer to reach di last 16 for di Africa Cup of Nations sake if di draw. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59998906 +sports UFC 248: Israel Adesanya na still champion, beat Yoel Romero by unanimous decision Israel Adesanya na still di middleweight champion afta e defeat Yoel Romero for fight wey many dey say e no sweet. For di UFC 248 event, di two fighters wey dey undefeated before dis match bin dey hope to go back house with di middleweight belt. By unanimous decision by di judges declare say na di Nigerian-born Israel, na im fight pass on di night. Afta round 5 di judges drop scores of 49-46, 48-47, 48-47 wey make Romero para and later complain about. Di fight wey many sabi pipo say no two sweet to watch, bin happun for di T-Mobile Arena for Las Vegas, American early mor mor on Sunday. Israel Adesanya wey im nickname na Stylebender, dey represent New Zealand wey be di kontri im parents migrate to. https://www.bbc.com/pidgin/sport-51781068 +entertainment Bruno Iwuoha: Nollywood mourn di death of actor Chief Bruno Iwuoha "Nigerians and plenty Nollywood actor's dey mourn di death of popular veteran actor Bruno Iwuoha wey die on Saturday 10 April 2021, according to tweet wey di AMMA awards post for Twitter. Di Africa premier and most prestigious films awards wey dey reward excellence in film making inside tweet say di actor go dey greatly missed. Also for inside statement wey plenty local tori report wey dem credit to di Director of Communications Actors Guild of Nigeria, Monalisa Chinda-Coker, confam di death of di movie star. Di National President of di actors guild, Ejezie Emeka Rollas bin condole wit di immediate family members, friends and fans. Di Nollywood actor die for di age of 68 afta long battle wit diabetes aacording to reports. Plenty Nollywood filmmakers describe im death as shocking, say di industry go miss am so much as dem pray for im family wey e leave behind. Until im death Bruno Iwuoha na one of di ogbonge movie stars for di kontri and e feature inside plenty films like World Apart, Sins of di Flesh, Occultic battle, among others. Im bin dey regular for Nollywood for di early 2000s and known for e 'soft spoken' voice. E win di Best Supporting Actor award for di 3rd Africa Movie Academy Awards for im performance for di movie ""Sins of the Flesh"" Bruno Iwuoha come from Ehime Mbano Local Government Area of Imo state. E dey survived by wife and six children." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56703766 +politics APC Presidential primaries: Bola Tinubu, Yemi Osinbajo, Rotimi Amaechi, Yahaya Bello - Meet APC aspirants wey wan replace Muhammadu Buhari as President "Election season don start for Nigeria and di race for who go replace President Muhammadu Buhari for Aso rock don dey hot. For im party - di ruling All Progressives Congress - about seven aspirant don declare dia interest to run for di highest office for di land. Di kontri general election go happun for 2023, according to di Independent Electoral Commission. Next year Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023 according to di election office INEC. While govnorship and state assembly elections go hold for March 11, 2023. INEC don give all political parties for di kontri deadline of June 2022 to do dia primaries and produce dia candidates wey go fly di party flag for di general election. Dis na guide to who dem be. Yemi Osinbajo na Nigerian lawyer, professor, and politician wey be di 14th and current Vice President of Nigeria since 2015 under di All Progressives Congress (APC). E serve as Attorney General of Lagos State from 1999 to 2007 and hold di title of Senior Advocate of Nigeria (SAN). For 1999, Osinbajo gbab appointment as Attorney-General and Commissioner for Justice for di cabinet of Lagos State Govnor Bola Tinubu. Afta e serve during both of Tinubu four-year terms, Osinbajo comot goment for 2007 and return to law. E follow dey do lecturing plus preaching for di Redeemed Christian Church of God. Before di 2015 presidential election, dem chose Osinbajo as running mate to APC nominee Muhammadu Buhari. Na dia ticket defeat di den-incumbent President Goodluck Jonathan and Vice President Namadi Sambo. Four years later, im win re-election. Bola Ahmed Tinubu alias Jagaban, na man of many parts and im don dey very active for Nigeria political life for many years now. Di 69 years old get reputation as a political godfather wey dey use im power and influence to support im candidates. Im na accountant wit degree from Chicago State University for United States, and im work for major companies including Mobil Oil Nigeria before im win senate seat for 1992. E later go on exile during di rule of military goment sake of im bin dey involved wit di pro-democracy National Democratic Coalition. Afta di death of military leader General Sani Abacha, im return for 1998 and immediately return to politics. Bola Ahmed Tinubu na two term govnor of Lagos state from 1999 to 2007. Although im bin no hold any political office afta 2007, but e get hand for di grooming of Lagos state govnors since den. Jagaban describe imsef as ""talent hunter"" wey dey ""put talents for office, I help dem,"" im tell tori pipo Reuters for 2015 during Lagos govnorship election. Rt. Hon. Chibuike Rotimi Amaechi na Nigeria Minister of Transportation and former Governor of Rivers State. Dem born am for Ubima, Ikwerre Local Goment Area of Rivers State on 27th May, 1965 to late elder Fidelis Amaechi and wife Mrs. Mary Amaechi. Amaechi start im educational for St. Theresa primary school from 1970 to 1976, where e pass im first school leaving certificate. Afta dat e proceed to Government Secondary School Okolobiri for 1977, finish dia and get im West African School Certificate for 1982. Amaechi later attend University of Port Harcourt for 1983, wia e graduate with honours degree in English Studies and Literature for 1987. Na for University of Port Harcourt e lay di foundation of im political life. Amaechi later become Rivers State Governor for 2007 to 2015 under PDP ticket. E also become Nigeria govnors forum chairman within dat period. For 2015 Ameachi become di Director General of President Muhammadu Buhari Campaign Organization. E occupy dis position again for 2019 afta Buhari bin appoint Transportation Minister wen e form him cabinet after 2015. And him still hold dat position till date. David Nweze Umahi, na two term govnor of Ebonyi state - e become govnor for 2015 under im former party, Peoples Democratic Party (PDP). E later join di All Progressive Congress (APC) for 2020. Dem born Umahi wey from Uburu for Ohaozara local goment area of Ebonyi State for for January 1964. Umahi enta politics early and by 2007 e become di acting chairman of di Ebonyi State chapter of di PDP. From 2009 to 2011 e serve as state chairman of di party. Oga Umahi later serve for di governing board of di Federal Medical Centre for for one year. Yahaya Bello na one of di youngest aspirant for di presidential race at 46 years old. Na 18th June 1975 dem born am and e from Agasa, Okene Local Government Area of di state. Bello na di be present govnor of Kogi state, for North Central region of Nigeria. E attend Government Secondary School Suleja for Niger State wia e obtain im Senior School Certificate Examination for 1994. From dia e attend Ahmadu Bello University Zaria to study Accounting wia e graduate for 1999. E go back to Ahmadu Bello University, Zaria to obtain a Master's degree in Business Administration in 2004. Im be di fourth democratically elected govnor of Kogi State. Rochas Okorocha na past govnor of Imo state and current Senator wey dey representing Imo West Senatorial district for di 9th national assembly. E serve as govnor from 2011 to 2019 first wit All Progressives Grand Alliance (APGA),before e decamp to di All Progressive Congress. Na APC okorocha dey now. Aside politics Okorocha na businessman wey get several investments for Nigeria like real estate. E also be philanthropist wey get foundation wey e dey use help poor children. At 59 years, Okorocha na one of di experience politicians for im party, because him don contest for di position of president before. Na 22 September 1962 for Ogboko, Ideato South, for Imo State dem born am. Dr. Kayode Fayemi na former Minister of Mines and Steel Development and present Govnor of Ekiti state. E serve as minister from 2015- 2018. During im tenure as Minister, he also serve as Chairman of di governing board of Nigeria Extractive Industries Transparency Initiative. Dr. Fayemi get degrees for History and International Relations from di University of Lagos and Obafemi Awolowo University respectively. E also get Doctorate in War Studies from King's College, University of London and na Fellow of di Centre for Peace and Conflict Studies, University of Ibadan. Fayemi na former coordinator of di Progressives Governors Forum and a two-time Chairman of di Nigeria Governors Forum. E say him entry into di race go rebirth a new Nigeria. Dem born Godswill Obot Akpabio for 9 December 1962. E complete im primary education for Methodist Primary School, Ukana, and from dia go Federal Government College, Port Harcourt, Rivers State for im O' and A' levels certificate. Akpabio Study Law for University of Calabar and attend Nigeria Law School for Lagos. E do work as teacher and for small time practice for Paul Usoro and Co. wey be law company. And work for EMIS Telecoms Limited wia im become company Managing Director. Akpabio journey inside politics begin for early 2000. E serve as Commissioner for Petroleum and Natural Resources for Akwa Ibom state. 2007 e become Akwa Ibom State Govnor under Peoples Democratic Party (PDP) ticket. Enta for second time for 2011. 2013 e become chairman PDP Governors Forum. 2015 e win Senatorial seas of di Akwa Ibom North West Senatorial District (Ikot Ekpene). 2015 e become Senate Minority Leader. August 2018 - Senator Akpabio resign as Senate Minority Leader and port to All Progressive Congress. July 2019 - President Muhammadu Buhari nominate am for Minister for Niger Delta Affairs. Senate confam am di following month for August 2019. For 2019, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin investigate oga Akpabio ontop alleged N100 billion (N258 million) fraud during im 2007 to 2015 time as govnor, although di corruption police no file any criminal charge las las. Ibukunle Amosun na senator and former govnor of Ogun State for southwest Nigeria. Na January 25, 1958 dem born am. E serve as Govnor for di Gateway state from 2011 to 2019. Senator Amosun na qualified accountant wey attend University of Westminster for London, United Kingdom wia e acquire Master of Arts in International Finance. Before e go school for UK e bin attend Ogun State Polytechnic, wia e graduate wit Higher National Diploma for 1983. Amosun during im declaration speech for president tok wia e go focus on. ""Di two pillars of di agenda wey I go torchlight in di weeks ahead na national security and economic development,"" e tok. ""Ontop dis two pillars, we go create a national architecture for human flourishing wey neva happun before for our national history."" Amosun add put Dr Tunde Bakare na pastor and founder of The Latter Rain Assembly church. Na November 11, 1954 for Abeokuta, Ogun State dem born Pastor Bakare into Muslim Family. Pastor Bakare say im journey into Christianity begin for September 24, 1974. E start im ministry for May 1988 wia e pioneer di first Model parish of di Redeemed Christian Church of God. Pastor Bakare na qualified lawyer, e do im call to bar for 1981. Im practice law wit Gani Fawehinmi Chambers, Rotimi Williams & Co and Burke & Co, Solicitors. Before him establish im own law firm Tunde Bakare & Co (El-Shaddai Chambers) for October 1984. Pastor Bakare na minister wey like to torchlight national issues. Im political journey start for 2011 wen im become running mate to Muhammadu Buhari for di now-defunct Congress for Progressive Change. Tein Jack-Rich na di founder of Belemaoil Producing Limited. Jack-Rich wey hail from Rivers State announce on Friday, 13 May say im go run for president on di platform of di All Progressives Congress. Dis na afta im submit im N100 million presidential forms to di party. Di 47-year-old entrepreneur study Petroleum Production Technology for Panola College Cartage, United States. Im also study Business Administration for di University of Wales, and Business Management for Usam University. During im speech as im formally declare for president, Jack Rich tok say e go focus on youth and women empowerment, infrastructure and job creation if e enta as president. Na former senate president wey come from Enugu state for eastern Nigerian. Na 2005 e become president of di senate, position wey e occupy until 2007. Asides politics Oga Nnamani get experience for business too, some of di companies wey im don lead na Export, Minerals and Finance Limited, DAEWOOE E & C to mention a few. Di former senate president na graduate wey school abroad. E attend Ohio University, Athens, USA wia e graduate wit Bachelor of Business Administration. Also e get Master of Business Administration for dat same university too. At 73 years, Oga Nnamani na one of di experienced south east aspirant wey dey di race. Senator Ahmad Ibrahim Lawan, na di current President of di ninth Senate. E dey represent Yobe North Senatorial District for northern Nigerian. Senator Lawan na one of di few northerner wey dey di race. Di Senate president na man wey go school well-well. E get Bachelor's Degree in Geography from University of Maiduguri. Master's Degree In Remote Sensing from Ahmadu Bello University, Zaria. And Doctorate Degree In Remote Sensing/GIS for Cranfield University, UK. Dem born Senator Lawan for December 1, 1959. Sobeye El, lawyer and APC member. Wit few weeks to di APC party convention more candidates don join di race to contest for president. Ekiti state govnor Kayode Fayemi and former Govnor of Akwa Ibom state Godswill Akpabio na di new faces for di race. As tins be so di fate of dis aspirants dey in di hands of di 2,260 APC delegates wey go vote to select di candidate wey go fly di party for 2023 general election. BBC Pidgin speak wit Sobeye Eli wey be lawyer and APC member for Rivers state to torchlight di presidential aspirant race for di ruling party. And dis na how him explain di matter for us. Di south west next to di north west na di biggest stronghold of APC in terms of di number of delegates wey go attend di national convention. ""Na natural tin as di party get stronghold dia, more hands go wan come on board. ""If you look di profile of di aspirants a lot of dem get experience in leadership for different levels. ""E dey difficult to predict for politics but by and large APC delegates go look at a few factors. ""Di outgoing president Muhammadu Buhari get important role to play if you wan read my mind dat na wetin go happun. ""By di time dem reach Abuja and di president moderate e go dey clear wia di whole tin dey go."" As per prediction, di president don already give hint for interview wey im do wit tori pipo Channels e tok two tins E say di pesin wey go succeed am go be younger pesin. ""Di second tin wey e tok na say him no go name im successor,"" Sogbeye tok For me di president go play major role to determine who go pick di ticket and di direction of wia di delegates vote go go. Nigeria ruling party All Progressives Party (APC) don set dia presidential primaries for May 30-31. We go dey update dis tori wit more aspirants profiles as dem dey come out one by one to declare dia intention." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61083547 +politics Chris Ngige: Bola Tinubu, Hon Faleke vs Minister 'palava' - "Chris Ngige, Honourable James Faleke and Asiwaju Bola Ahmed Tinubu drama wey happun on di floor of Nigeria House of Representatives still dey make pipo wonder why. Tori be say Ngige, Nigeria Minister of Labour and Productivity tell Faleke wey dey represent Ikeja Federal constituency say im dey on di same level wit Tinubu, di National leader of di All Progressives Congress. E happun say di lawmakers bin invite Ngige make im come tok wetin im know as dem dey torch light why di minister suspend di management of di Nigeria Social Insurance Trust Fund. Di minister accuse di management say dem embezzle 48 billion naira fund. As di House of Representatives Ad Hoc Committee on di Arbitrary Breach of Presidential Directive on di Suspension of Management and Executive Members of NSITF and oda goment Agencies by Ministers begin question am, oga Ngige tell di lawmakers say im senior all of dem. E change am for Faleke say both of dem no be age mate, say im dey di same level wit Faleke oga, Bola Tinubu. He say apart from say im and di former Lagos state govnor be age mate, dem get di same political achievements. Oga Ngige tok say ""Faleke dem say you don reach 60, sure you near my age, but I use at least seven years senior you. I dey di same age wit your mentor for Lagos, Aswaju. I be govnor di same time wit am. He be senator, I be senator too. I be minister for two times and im don do minister before"". Faleke reply, yab am say Tinubu win all im elections well and e no do wuruwuru. Di minister give am back sharperly say ""no problem, just like you win your own election for Kogi State very well. Na only you be deputy govnor and govnor of Kogi state."" Wen Faleke say make e respond to di questions di committee dey ask am, Ngige tok say I dey respond my friend, if you yab me, I go yab you ten times. ""I be Lagos boy, you na small boy for Lagos. See dis Mushin boy, he dey follow Victoria Island boy tok. See dis Mushin boy from Kogi"". Many pipo for social media don shook mouth for di mata and hope say e no go turn tribal war. On top why di lawmakers invite am, Ngige tok say di Nigeria Social Insurance Trust Fund management go get opportunity to clear themselves of di financial fraud wey dem dey accused of. Oga Ngige tok say im no go contrary to di presidential directive and dat di suspension follow procedure in line wit relevant authorities. Ngige also accuse di NSITF say dem fail to submit Annual Audited Accounts wey go epp prepare annual reports for Mr President." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53511008 +sports Checkout some of di major highlights for sports for 2021 "From Football to Tennis to Basketball, plenti moments dey wey totori fans belle and oda moments wey make pipo sad for 2021. Make we tok about some monet wey spark ginger for fans and sport lovers for 2021. Lionel Messi na one of di big names for football, no be only becos e dey score goals and break records, but as he spend most of im professional playing years for im boyhood club Barcelona. Wen Barcelona announce on August 5 say Messi go leave di club afta almost two decades sake of ""financial and structural issues"" e shock plenti pipo sotay some Barcelona fans cari ""we no go gree"" waka go Camp Nou. For im press conference on August 8, Messi shed tears as e dey bid Barcelona farewell "" I come here to tell una bye bye"" Messi tok. Di 34-year-old Argentina captain comot Barca - di only club e don ever play for - as dem bin dey unable to afford a new deal under La Liga financial fair play rules. Like play like play Portuguese superstar Cristiano Ronaldo tell Juventus say im no dey do again. Tori come dey fly upandan as pipo no know wia him go go next. Football fans surprise to see say Ronaldo dey return to im former club Manchester United and di Premier League club afta 12 years. Di Moment Manchester United on August 31 announce say dem don complete di signing of Cristiano Ronaldo from Juventus on a two-year deal, emotions burst, as Manchester United fans dey happy oda rival fans dey provoke. Ronaldo win 8 major trophies between 2003 and 2009 for Manchester United. UEFA Champions league na di biggest club football completion for di world, na a tin of pride to win am. From di group stage many football pundits no believe say Chelsea stand a chance to win, especially as dem dey face rival Mancity for di final. May 29 na one of di moments for 2021 as Chelsea beat Manchester City 1-0 to win dia second UEFA Champions League title afta almost one decade wey dem don dey wait. On 29 November, Lionel Messi smash anoda football record to win im record 7th Ballon d'Or go remain for pipo head for a long time. Messi beat im closest rival Robert Lewandowski with 33 points to win di award afta im get 613 points in total, while Lewandowski get 580 points. Alexia Putellas win di women category with more than 186 points to beat her rival Jennifer Hermose wey get 84 points. On May 31, di Tennis world shock as Naomi Osaka tok say she go withdraw from di French Open sake of her battle with depression. Naomi Osaka wey be four-time Grand Slam winner, and World number two dat time withdraw from di French Open afta controversy wey start di time she to gree tok wit tori pipo for di tournament. Na for one tweet wey she tok say ""suffered long bouts of depression"" ""I no wan be distraction"" she tok Di delayed Tokyo 2020 wey happun for inside 2021 sake of COVID-19 get e own emotional moments. One of di emotional moments come from world's most successful gymnast Simone Biles on May 27 comot from di gymnastics women team final for Tokyo Olympics. She tok say di decision na sake of her mental health. Simone Biles record her lowest score for her Olympic career on top Vault as she no land well. Dem replace her with Jordan Chiles. Nigeria Blessing Oborududu win Nigeria first medal for Wrestling.silver as she lose to USA Tamyra Marianna Stock Mensah for di final of di women 68kg freestyle event. Di 32-year-old lose 4-1 on points to di American Tamyra Marianna Stock Mensah for di final of di women 68kg freestyle, but na celebration, emotional and historic moment for Nigerians. July 11, 2021 na one day wey football lovers for England and around di world no go forget quick quick. Di tension and anticipation dat day too much as England bin dey hope say dem go win dia first major title afta Fifty-five years we dem don dey wait. Evritin bin dey go well for di Three Lions when Luke Shaw score afta two minutes wey match start. Italy, wey neva lost any of dia last 33 matches before dis final, come back into di game wen Italy score di equalizer for second half. Di tension continue to increase, afta extra time, e enta penalty. E pain England well well as England manager Gareth Southgate and im players, miss three out of dia five penalties. Marcus Rashford hit post, Gianluigi Donnarumma stop Jadon Sancho before Arsenal teenager Bukayo Saka go play, but di Italian goalkeeper save di penalty. Bukayo Saka cry as notin dey to use console di fans wey full Wembley stadium. Inside September 27, 2021 na im Nigeria Women Basketball Team D'Tigresses win di FIBA Women's Afrobasket for 2021 Nigeria beat Mali 70-59 for di final wey happun for Yaounde, Cameroon on Sunday to still hold dia continental title for di third time back to back. Dis victory make dem di second African team to win three or more dan three title afta Senegal wey don win am back to back five times, from 1974 t0 1984. Nigeria win for di first Women's AfroBasket wey happun for Bamaka, Mali for 2017 For 2019 na Dakar, Senegal dem win am, and di 2021 edition for Yaounde, Cameroon. Basketball na one of di sports wey dey rub shoulder wit football for Nigeria." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59840791 +entertainment Big Brother Naija 2020 housemates: Terry Waya billionaire son Terseer Kiddwaya na contestant for BBNaija season 5 'Lockdown' "Terry Waya billionaire son na contestant for Big Brother Naijaa 2020 Lockdown season. Terseer Kiddwaya na 27 year-old self-employed man wey come from Benue State. E describe himsef as confident, good looking, ambitious and pesin wey dey highly motivated. E say im also dey confident and arrogant all at di same time and love travelling. Di grand prize for di Big Brother Naijaa 2020 Lockdown season na 85 million naira. Arrogant and confident, na wetin Kiddwaya say im dey cari waka enta Big Brother House. Being a Big Brother Naija season 5 Housemate don make Kiddwaya dey expect a better and crazier 2020. E describe himself as confident, good looking, ambitious, a daredevil wey dey highly motivated. ""You never know wen your time don finish, so you fit as well go for am"" Dat na Kiddwaya favourite words. ""Getting into health and fitness na im Kiddwaya say be im biggest achievement. I bin dey quite chubby, so I transform my bodi and I don dey consistent ever since."" Kiddwaya papa Terry Waya, wey be famous socialite na London-based Nigerian businessman. Oga Waya age 55 bin reportedly face some kain case for British court between 2006 and 2008. Terry Waya na native of Tiv for middle belt Nigeria. Di Nigerian socialite wey love Versace wella bin give interview for May 2020 to Nigeria lifestyle and celebrity tori pesin Dele Momodu." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53495821 +sports Diego Maradona dead: Argentina begin three days of mourning to mark di death of 'god' "Today football superstars Lionel Messi and Cristiano Ronaldo ""no fit even dream"" of di way di world admire Diego Maradona, na so e former teammate Ossie Ardiles tok. Argentina don begin three days of national mourning to mark di death of Maradona wey die on Wednesday for di age of 60. Im body go lie in state for di Casa Rosada wey be di seat of di Argentina goment. ""To be Diego Maradona bin dey incredibly beautiful,"" na so oga Ardiles tell BBC. ""But on di oda hand, e bin no dey easy at all. Right from a really early age, e bin dey subject to di press all di time. E bin no get normal childhood, e no ever get normal teenage years. ""Everybody bin want dey wit am, everybody bin want piece of am, so e bin dey incredibly difficult. Maradona, wey play for clubs including Barcelona and Napoli, bin captain Argentina wen dem win di 1986 World Cup, as e score di famous 'Hand of God' goal against England for di quarter-finals. Former Tottenham midfielder Ardiles, wey play alongside Maradona for di 1982 World Cup, say e bin be like ""god"" for Argentina, in Naples and all around di world. ""Di world go remember am as genius in football,"" e add. ""You fit see di extraordinary amount of interest wey e dey generate. ""Pipo like [Juventus and Portugal striker] Ronaldo, or pipo like [Barcelona and Argentina forward] Messi, dem no fit even dream of getting dis kind of admiration. ""Dat na im be di Maradona phenomenon - all di time."" A post-mortem examination bin dey due to take place on Maradona dead body later on Wednesday afta e die at about midday local time for e home in Tigre, near Buenos Aires. Di former Argentina attacking midfielder and manager bin do successful surgery on brain blood clot earlier for November and bin suppose collect treatment for alcohol dependency. One minute silence bin take place before Wednesday Champions League matches and di same tin go happen before all other European fixtures dis week. Messi and Ronaldo bin dey among current players to pay tribute, while Brazilian football great Pele say e hope one day dem two go ""play ball together in di sky"". Manchester City manager Pep Guardiola say Maradona ""make world football better"". ""One banner bin dey for Argentina, one year ago, wey I read bin say: 'No matter wetin you don do with your life, Diego, wetin matter na di tin wey you do for our lives,'"" former Barcelona and Bayern Munich boss Guardiola add. ""It express perfectly wetin dis guy give us. Di man of joy and pleasure and e commitment for world football."" Former Tottenham manager and Argentina defender Mauricio Pochettino say: ""Broken with pain. Diego, you be my hero and friend. I bin dey fortunate to share football and life with you."" Di Vatican say Pope Francis, wey come from Argentina and a football fan, go remember Maradona for e prayers." https://www.bbc.com/pidgin/sport-54939525 +sports Why 26-year-old professional footballer Amir Nasr-Azadani dey face possible execution for Iran "One Iranian professional footballer, Amir Nasr Azadani dey face possible execution over im role for campaigning for women rights for di kontri. Iran don witness serious protests in recent months wit citizens dey revolt against di regime of di Supreme Leader Ali Khamenei. BBC report say di protest start wit di death of 22-year-old Mahsa Amini wey di authority allegedly kill afta dem say she disobey di rule of covering her hair for public place. Her death make top actresses and football players join di struggle. Di Iran football team recently refuse to sing dia national anthem during dia opening game for di World Cup against England. Amir Nasr-Azadani, a former player for di Rah-Ahan, Tractor, and Gol-e Rayhan football teams, dey in in danger of execution. Di Islamic Republic judicial system dey plan to hang am for crime wey dem dey call ""moharebeh"". On 17 November 2022 tori come out say one Colonel Esmaeil Cheraghi die during nationwide protests. Three days later, on 20 November di state-run broadcaster IRIB, release video of di forced confessions of three pipo wey say dem get hand for di murder of Cheraghi. Afta di video, authorities later publish di names of di Iranian player Amir Nasr-Azadani as one of di suspects – di oda two pipo na Saleh Mirhashmi and Saeed Yaghoubi. Local tori pipo say true-true Azadani follow for di protests but say e get hand for di killing of di army oga na lie becos e no dey di area wia di man die. Many current and former Iranian football stars don tell goment to revoke di death sentence. Dem born Nasr-Azadani for February 1996 for Isfahan. He start to play football for primary teams for Sepahan Isfahan. For 2014, e become a member of di Tehran Rah-Ahan team and play for Iran Premier League for di first time. E join Tractor a year later and be member of di team until 2019. E become a member of di Gol-e Rayhan football team for Iran first football league for 2020. Dis news dey come as Iran don already carri out di second execution in connection to di anti-goment protests wey don overtake di whole kontri. Authorities hang Majidreza Rahnavard, 23 ""for public"" early on Monday for di city of Mashhad, di judiciary announce. Revolutionary Court convict am of di charge of ""enmity against God"" afta dem find say Rahnavard bin stab two members of di paramilitary Basij Resistance Force to death. Di judiciary Mizan news agency report say dem hang Majidreza Rahnavard ""in di presence of one group of Mashhadi citizens"". Dem hang Rahnavard only 23 days afta im arrest.One video broadcast by state TV afta im arrest on 19 November show Rahnavard as dem tie im eyes and wit im left arm inside cast. For di video, im say im no deny attacking di Basij members but no remember details because im bin no dey in di right state of mind. Di first execution happun on Thursday 8 December, and e cause international condemnation. Court convict Mohsen Shekari, 23, of ""enmity against God"" afta e find say im attack one Basij member wit machete for Tehran. On November 1, di court find am guilty of fighting and drawing weapon “wit di intention of killing, causing terror and disturbing di order and security of society.” Iran authorities hang Mohsen on Thursday morning afta dem accuse am say im na “rioter” wey block one main road for Tehran for September, plus injure one member of di paramilitary force wit machete. Iran Human Rights say dem no let Mohsen get access to im lawyer “throughout di interrogation phase [and] legal proceedings.” Mahmood Amiry-Moghaddam, director of Norway-based Iran Human Rights, tok for Twitter say Rahnavard sentencing dey based on ""forced confessions, afta one unfair process and a show trial"". ""Dis crime must dey met with serious consequences for di Islamic Republic,"" e tok, adding say ""serious risk of mass execution of protesters"" dey." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c51ez7wy3dyo +sports Onguéné Gabrielle: Why ah wan komot Cameroon women football from 'darkness' "Aboudi Onguéné Gabrielle, captain for Cameroon women national team, president for ""Terre Promise' association, say e wan komot women football from 'darkness'. Di Russian champion for 2019 with CSKA Mosco make de statement for 'GO7 Awards' prize award weh e organise for compensate de pipo weh deh work hard for 2018 football season. Na de first prize award weh player weh e still bi active wit national team don organise for encourage women football. ""We wan komot football from darkness, na why we organise de awards. For dis first edition we bi satisfied and we know say we go adjust weti weh e no work fain next taim""- Onguéné tok. Cameroon women football shine for world stage for 2015 wen Lionesses go World Cup for de first taim wit players laik Aboudi weh deh take de team for knock out stage. Since den, Aboudi say tins di change small-small but e also check say taim don reach for shake tins for women football. Cameroon women football don enta for number nine day of play now dis season. Best player, coach, scorer for last women football season take home balls, boots and moni from Aboudi weh e dey shortlist for CAF Awards wit four odas. Aboudi, striker for national team, football for yi na gift, and as player weh e start for young age di play wit boys dem, say na e own small contribution for komot women football from darkness. ""We no bi know say woman football dey and plenti of we start play wit boys, na so ah develop, but as model for some players now ah wan motivate dem"", Aboudi tell BBC News Pidgin. ""One hand no di tie bundle and ah check say award fit push some clubs and players for achieve more"". One of de winners, Marian Ngo-ese player weh e touch pipo dia heart last football season, tell BBC News Pidgin say e hard work pay wit de award. ""Ah glad as Aboudi weh e don always encourage me don start dis award, na big push for woman dem"", de player tok. Celine Eko president for women football league, say Cameroon football executive committee don decide for support Aboudi for dis wandaful activity next year, for organise de award wit de plyer, e announce for BBC News Pidgin." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50707955 +business Ghana Presidency blow Ghc70 million on foreign trips den ‘item 13’, minority want probe "Minority for Ghana parliament dey call for probe into how Ghana Presidency blow Ghc70 million on foreign travels, hotel accommodation den item 13 between January den September, 2019. De figures emerge after documents on operations expenses of de Presidency go before Parliament, but some minority members start dey question how dem fit blow that kind of money within 9 months. ""What sort of operational expense be dis? He dey buy new plane from 62.5 million cedis. Refreshment, partying, tea 1.980 almost 2 million Ghana cedis on refreshment. De Vice President en office too be similar. We for demand accountability"" Cassiel Ato Forson explain. But government say de minority dey make noise sake of dem no overspend dema budget for de Chief of Staff office. According to Deputy Chief of Staff, Abu Jinapor ""dis no any leak or something, but e be dem send that document go Parliament for de sake of transparency on how dem spend money for de 2019 period."" ""We do dis to demonstrate to de finance committee say de amount dem approve nu, dem stay within de budget"" Mr Jinapor add. Dem spend Ghc 62 million on foreign travels, Ghc 5.8 million on hotel accommodation den Ghc1.9 million item 13 den stuff. Dis be how some of de operational costs wey de Presidency incur." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50863568 +entertainment Boma BBNaija: 'Those wey dey send me death threats na back to sender for dem' BBC Pidgin interview evicted Big Brother Naija housemate, Boma wia im tok about wetin happun between am and Tega, plus di fight wit Angel and life afta di show. Im open up about threats wey im dey get from pipo sake of di 'relationship' between am and Tega for di house. Di former housemate also tok about going through mental health challenges and why im dey reason to work on projects wey dey help pipo deal wit depression. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58495475 +entertainment Non-binary: Five celebrities wey dem dey call They/Them "Non-Binary status don dey our society for a while, e dey used by pipo wey no wan dey characterized by one particular gender. Recently, Demi Lovato announce say e no go dey use she/her pronouns for her name again, say herr new pronouns na they/them. But oda celebs dem for obodo oyibo don take di move of gender fluidity. Here be four of them: While Miley Cyrus no dey use di they/them pronouns, for 2015, for Time Interview she bin comot as gender fluid wey she tok say she no fit into di gender boxes wey dem dey try put pipo inside. She tok give Time for interview say she dey equal and even and e no get anything to do with how she dey dress or how she look. British Musician Sam Smith bin comot for 2019 as non-binary even as dem bin take di pronouns they/them. E tok for Instagram post say, ""afta a lifetime wey I bin dey fight my gender, I don decide to embrace who I be for inside and out"". Dis dey come six months afta dem tok say dem no feel like woman or man but dem dey in-between. Australian Actress, Ruby Rose comot as gender fluid for 2014 afta she bin comt with a video about gender roles wey she call Break Free. Di Batwoman star still dey use feminine pronouns although she bin tok for interview say she no be male or female. She tok say she bin spend most of her childhood say she be boy even as dem born as girl sotay she pray sy make she no get breast. Music star, Janelle Monáe bin comot as non binary for Twitter for 2020. For her Twitter bio, she list her pronouns as ""they/she/them/her/..."". British actress, Cara Delevingne for 2018 say when she find out about gender fluidity na one of di happiest days of her life. Di Suicide Squad actress tok say she dey feel different all di time, sometimes feel more like woman, oda days she dey feel like man." https://www.bbc.com/pidgin/world-57174684 +business Elon Musk net worth: SpaceX, Tesla CEO tie with Bill Gates as di world second richest man Elon Musk climb ontop di ladder of di world richest men continue on Monday as di Tesla and SpaceX CEO net worth skyrocket. Di shares of im electric automaker hit record high, dis wan boost im net worth to $127.9 billion, according to Bloomberg Billionaires index, wey track di world 500 wealthiest pipo. For some hours, hous, e even go slightly above Bill Gates, di co-founder of Microsoft (MSFT) and di world second-richest pesin, wey im worth dey estimated to be $127.7 billion. Di latest from Bloomberg index na say di dey men dey tied on $128 billion each. Musk fortunes dey directly linked to Tesla own. Im biggest asset na di company stock, of wey e get about 20%, according to Bloomberg. Tesla stock don shoot up almost 524%, dis year 2020, Musk add more dan an estimated $100 billion to im wealth. Although Gates go likely be bigger billionaire if no be for im philanthropy. E and im wife, Melinda Gates, promise years ago to donate most of dia wealth to charity. Amazon (AMZN) CEO Jeff Bezos na currently di world richest pesin, e get an estimated net worth of $182 billion. Born in South Africa, Elon Musk make more dan $160m from di sale of online payment service PayPal to eBay. Im desire to see humanity become true space-faring civilisation na di driving factor behind di founding of SpaceX. But he don also involve for di founding of oda companies like electric car manufacturer Tesla. He also reason out di project, Hyperloop, one high-speed transportation system wey dey use pods wey dey travel through system of tubes. Im colourful personality and lifestyle make am di inspiration for Robert Downey Jr interpretation of Marvel Comics character Tony Stark. Tesla Inc wey dem bin dey call Tesla motors na American electric motor company wey base for California. Na electricity di motor dey use function instead of fuel. Dem found di company for 2003 and afta 11 years Tesla become di number one selling plug-in and battery electric passenger car manufacturer for 2019. Tesla cars account for 81% of di battery electric vehicles wey dem sell for di whole of United States for di first half of 2020. SpaceX na American company wey dey provide commercial and government launch services ontop im Falcon 9 and Falcon Heavy rockets. Entrepreneur Elon Musk found di company for 2002, with di goal to reduce space transportation costs, to enable di colonisation of Mars. SpaceX don dey conduct regular flights of cargo to ISS, and go now aim to begin dey launch astronauts. Musk company dey also develop bigger spacecraft to carry humans - wey dem called Starship - wey fit begin di process of settling Mars. https://www.bbc.com/pidgin/world-55060038 +business Chinese or Nigerian no foreigner for do retail business for Ghana – Prez Akufo-Addo "Ghana President Akufo-Addo say Ghana Union of Traders Association no make any mistake in dema interpretation of de law wey dey ban retailers from de local markets. Until say de laws of Ghana go change, e be wrong say any foreigner go operate retail business for Ghana. ""GUTA be right…de laws of Ghana ban foreigners from retail trade for wana market. Pipo wey no be Ghanaians no fit sell for wana market top"" President Akufo-Addo explain. President Akufo-Addo talk dis matter during en encounter plus local media for de country today. He explain say e no matter who de foreigner be, whether Chinese or Nigerian, de laws of Ghana dey ban dem all from retail business. De Ghanaian leader also complain about how Nigeria close dema border sake of rice smuggling. He explain say dema border closure affect like 300 Ghanaian trucks which lock up between Naija den Benin border. ""We for find better solution to internal trade than border closure"" he add. Tension between Ghana den Nigerian traders drag throughout de year 2019. On over five occasions Ghanaian traders lock up shops of dema Nigerian counterparts who dem say no for operate in de retail market. De trade war create tension between both counties who still no find solution to de issue. Ghanaian President Akufo-Addo say he government go work hard say say dem fit enforce de law wey dey ban foreigners from retail trade inside de country." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50786202 +sports Kurt Zouma: West Ham condemn defender as video wey show am dey hit pet cat go viral "West Ham United don ""unreservedly condemn"" Kurt Zouma for hitting im cat after one video wey show France defender dey kick and slap im pet go viral. Di video show di 27-year-old Zouma as im dey kick di cat across di floor and slap am for face. Zouma don apologise and di club say dem go deal wit di incident internally. ""I want to apologise for my actions. E no get any excuse for my behaviour, wey I sincerely regret,"" di centre-back tok for one statement. ""I also want to say how deeply sorry I dey to anyone wey di video upset. I go like to assure everybody say our two cats dey perfectly fine and healthy. ""Our whole family love and cherish dem, and dis behaviour na isolated case wey no go happun again."" Zouma brother Yoan na im feem di video wey The Sun news first publish, e show di player as e dey throw show at di pet and den chase am around one room. ""West Ham United unreservedly condemn di actions of Kurt Zouma for di video wey circulate,"" di club wey sign di defender for summer from Chelsea for £29.8m tok. ""We don speak to Kurt and we go deal wit di matter internally, but we go like to make am clear say we no dey in any way condone cruelty towards animals."" Royal Society for Prevention of Cruelty Animals tok-tok pesin say: ""Dis na very upsetting video. E no ever dey acceptable to kick, hit or slap animal, for punishment or otherwise. ""We dey so grateful to people wey report di suspected animal suffering to us and we go like to reassure people say we go always look into and, if necessary, investigate any complain wey una carry come give us about animal welfare."" Professional Footballers' Association chief executive Maheta Molango also criticise Zouma as im give evidence to a Digital, Culture, Media and Sport select committee on Tuesday. ""Dis no be for us to discipline am, na for im employer to discipline, but our role na to tell di player say dis type of behaviour no dey acceptable,"" im tok. Di Metropolitan Police no go investigate di incident." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60306071 +business Di Spanish village wey dey on sale for €260,000 "By Guy Hedgecoe BBC News, Madrid For anyone wey dey dream of selling up and moving to di kontri, how about to buy an entire village? Salto de Castro, for north-western Spain, dey up for sale and di asking price na €260,000 (£227,000; $259,000). E dey located on di border with Portugal for di province of Zamora and a three-hour drive from Madrid, Salto de Castro get many of di buildings you go expect to find for small Spanish town. Dem include 44 homes, one hotel, one church, one school, one town swimming pool and even one barracks building wey used to be house to di civil guard. But weti e no get it does not have are inhabitants. Salto de Castro don dey abandoned for more dan 30 years. Di owner buy di village at di beginning of di 2000s, with di intention of converting am into a tourist spot. However, di eurozone crisis prevent di plan. ""Di owner get di dream of having a hotel here but all of dem dey put on hold,"" Ronnie Rodríguez, of Royal Invest, the company representing di owner tok. ""E go still like di project to come true."" For di Idealista website wia di property dey listed, di owner, wey dey for im 80s, say ""I dey sell becos I be urban-dweller and no fit maintain di upkeep"" of di village. E don attract interest, with more dan 50,000 visits since dem list am a week ago at dat price. Mr Rodríguez say 300 pipo don express an interest in buying, with inquiries from Russia, France, Belgium and the UK. One potential buyer don already put money down to reserve am, e tok. Na di electricity generation company Iberduero Salto de Castro bin build di house for families of di workers wey build di reservoir next door, from di early 1950s. But di inhabitants move comot afta dem complete am and di village come become totally abandoned in di late 1980s. Di area surrounding am na part of wetin don become known as ""emptied Spain"" - rural area wit few population wey lack many of di services wey pesin go find inside towns and cities. Salto de Castro bi don dey up for sale before, for as much as €6.5m. However, with no buyers and many of di buildings wey don dey vandalised, di price don go down. Di asking price of €260,000 dey enough only for one-bedroom apartment for top areas of Madrid or Barcelona. But di eventual buyer of Salto de Castro go need get deep pockets, at least in order to attract visitors. According to Idealista: ""Di investment wey dey required in order to make di village 100% workable and to become profitable no go pass €2m.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c98w82vevveo +politics Rivers State local government election update: PDP win all di Chairmanship, Councillorship seats for Rivers local goment elections "Di Peoples Democratic Party PDP don win all di chairmanship positions for di 23 local goment areas for di just concluded local goment polls wey hold for di State. Chairman of di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC), Justice George Omereji (Rtd) announce di winners for di chairmen of di 23 local goment areas and Councillors for all di 319 wards for di RSIEC Headquarters, come tell all di winners to carry di odas wey no win along to serve di pipo and work to develop dia local goment and di State. ""Winners and losers remain members of di same family, after election make una respect each oda work togeda to develop di State."" Justice Omereji also thank all di security agencies for dia support to ensure peaceful and violence free elections. Im come add say dem go give di certificate of return to all di winners on Monday, 19 April, 2021 by 12noon for di RSIEC headquarters for Port Harcourt. Meanwhile, some political parties don dey protest di results of di local goment election wey hold for Rivers State, dem call for cancellation of di election results. Di African Action Congress AAC as dem call for cancellation of di election say di election na big embarrassment to democracy. For statement wey di State Chairman of AAC, Progress Ogbokuma Aselemi sign, im ask federal goment to scrap State Independent Electoral Commission as dem don lose credibility and neutrality to conduct elections. Similarly, di Social Democratic Party SDP don also call for cancellation of di local goment elections wey RSIEC conduct. Dem also call for fresh conduct of di local goment polls with new Chairman of di electoral commision." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56783284 +entertainment Rosy Meurer: How pipo dey react to Tonto Dike ex-husband Olakunle Churchill new son with Rosaline Meurer "Nigerians don begin dey react to di news of Nollywood actress, Rosaline Meurer and her husband, Olakunle Churchill wey welcome dia first pikin togeda. Dis na afta Olakunle Churchill announce di news for Instagram and add say di decision wey e make to marry Rosy Meurer two years ago no be mistake but na divine ordination; ""Dis na moment of bliss and Celebration to us as I announce di coming of King Churchill Junior,...from my formative years I don always get di royal tag of ""King"" for my kids to dey greater than di father. Ahead of di mother day, I say big congratulations to my lovely wife for dis great testimony. "" ""Dis decision I make two years ago no be mistake but divine ordination. ""My little King, welcome to di world, a great addition to di family...My son ""King Churchill"", my ernest prayer be say you go dey greater than your father and your age mates for everything you do."" Also, Rosaline Meurer post for Instagram to welcome di birth of her son and write say di first day of her son life na di best day of of her life. Di news of di birth of 'King Churchill jnr' surprise plenti pipo as dem no even know weda Rosaline Meurer bin dey pregnant in di first place. In addition, e neva too tey wey pipo for public get to know about di marriage between Olakunle Churchill and Rosaline Meurer even though di marriage don happun two years ago according to Churchill. Although many of Churchill and Rosy followers for Instagram say congratulations to dem afta dem break di news for social media, some odas for di post wey BBC Pidgin share get mix feelings. Odas for Twitter express how dey feel about di news. Olakunle Churchill na di ex-husband of Nollywood actress, Tonto Dikeh and two of dem get one pikin togeda" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56336619 +politics Edo election update: Why Edo state matter to APC "Politics na game of numbers and every state dey important to any political party. For Nigeria ruling All Progressive Congress party, di more states wey dem get to govern, di more power wey dem go fit enjoy on top different states. Until Edo state governor Godwin Obaseki bin resign from APC on June 16, 2020, di party bin dey control 21 states while opposition Peoples Democratic Party bin dey im charge of 15 states. As govnor Obaseki register as PDP member on Friday June 19, e mean say di party now get 16 states, at least till di September 19 happun. On top of dat, Edo na di only state wey APC bin fit get for South-South Nigeria afta di 2019 govornorship election for Nigeria. Lawyer and political sabi pesin Liborous Oshoma, say as long as APC remain for Edo state, e go easy for dem to get di oda south south states. ""Since 2016, APC, apart from Edo state neva fit grab any oda state for di south south and as dem wan show say dem be national party wit spread across all di geographical zones, dem go also wan win di election for Edo, dat go also fit help dem enta di oil rich Niger Delta."" If APC fail to win di govnorship election wey suppose happun on September 19, dat go mean say di party no get any power at all for di oil rich Niger Delta region. Anoda reason why APC want Edo na sake of di power struggle between di party national chairman Adams Oshiomhole and di govnor Godwin Obaseki. Oga Oshoma say, ""for Adams Oshiomhole, govnorship election for di state go be big statement for am to stamp e authority back as many pipo dey blame say im make di party lose di state to PDP."" E add say, di fact say di govnor port go PDP many pipo no happy at all as dem feel say di govnor don cari dia mandate go anoda party and dem go want am back. Plenty gbas gbos don already happun between di two inside Edo APC as di state dey prepare for election. Di gbege hot sotey e dey affect di national body of di party, and more gbege still dey road. One very strong effect of dis wahala na di fact say now di party get two acting national chairman, one wey court appoint afta e uphold Oshio Baba suspension and di oda wey di national working committee (NWC) appoint. Di two chairmen don begin dey give different order. While Victor Giadom wey court appoint say, im don cancel all decision wey Oshiomhole don make since court suspend am for March 4; Hilliard Etta wey NWC appoint say make e act as chairman to continue from wia oga Oshiomhole stop before appeal court confam im suspension on June 16. Giadom faction say dem no give instruction for di party to do primary today Monday 22 June, but Etta faction say primary must to happen today."" Lawyer Oshoma say, if dem continue to dey give counter order, e go easy for ""di court to say since una bin dey give directive and counter directive therefore e no clear for INEC to monitor wetin una dey do."" As di ruling All Progressive Congress party do dia govnorship primary today so many gbege dey ground already wey fit affect di party chance to control di state. ""If at any time di court say Giadom na di authentic acting chairman and im insist say im no go do primary witin di time of INEC guideline, e den mean say APC no get candidate. But if na otherwise den e mean say di primaries wey APC do today dey valid"" na so Oga Oshoma tok." https://www.bbc.com/pidgin/media-53137088 +entertainment "Nicki Minaj new song Mixtape ""Beam Me Up Scotty"": American rapper explain why she take long break from music and wetin next" "American rapper Nicki Minaj don return to di music scene afta long break. After she shock fans wit unexpected Instagram tease on Monday, di singer on Friday rerelease her 2009 mixtape ""Beam Me Up Scotty"" on streaming services . Dis dey come months afta Nicki announce retirement from music for September 2019. ""Dis na just to get back to di basis a little bit, to di essence of why I begin dey rap"", Nicki tok about why she decide to re-release her 2009 mixtape Di rapper also tok during one Instagram live she do on Friday, say she don add three new tracks to di original project. ""I know say if I just rerelease di mixtape without putting anything new, I know say una go abuse me out,"" Minaj tok. Di mixtape new adds include ""Fractions,"" a ""Crocodile Teeth"" remix wit Skillibeng and one return to di Young Money team ""Seeing Green"" wey feature Lil Wayne and Drake. For di live video, Nicki also explain why she take a long break from music only to return now. ""Di little hiatus na because I dey for mommy mode but also because I dey go through wetin dem dey call 'writer's block' And if you be artist, no matter wetin you do, you no really fit flex your art di way you bin dey do am. So I bin go through a little bit of writer's block and I be like damn..."" Di ""Super Bass"" rapper never release any new album since 2018 wey she release ""Queen"" and her last single na ""MEGATRON,"" for June of 2019. For September 2019, Minaj shock fans wen she announce say she dey step away from music. ""I don decide to retire & have my family,"" she bin write on Twitter. She later turn back for one interview wit Billboard, to say ""I love music and interacting wit fans, so I no really see taking myself completely away. But I wan dey open to other possibilities in my life,"" she tok three months afta her initial announcement. On Sept. 30, 2020, she and husband Kenneth Petty welcome dia first child together, a baby boy." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57120409 +politics PDP Primaries in Edo State: Gov. Godwin Obaseki win Edo PDP Primaries unopposed just three days afta e join Nigeria main opposition party Edo State Govnor, Godwin Obaseki don become PDP govnorship candidate for di Edo election wey go happun for September, 2020.Di Govnor return unopposed afta im only only rival for di primary election, Ken Imasuagbon, step down for am. Obaseki win di Edo PDP Primaries unopposed just three days afta e join Nigeria main opposition party. Imasuagbon, wey bin tok say im no go step down for Obaseki before di primary election announce im withdrawal just some minutes before di party primaries start. Anoda arc rival of Obaseki for di PDP ticket, Engr. Gideon Ikhine bin step down earlier for di incumbent governor, wey comot from di All Progressive Congress (APC) wen di party disqualify am to contest for di primaries before im go join di opposition party, PDP, on Friday. Even though Imasuagbon don step down from di contest wia 2,229 delegates go choose di PDP governorship flagbearer, di voting still happun to confam say na Godwin Obaseki be di PDP govnorship candidate. So as e be so, stage don set for di battle between di main contenders for di 19 September, 2020 election wey be Pastor Ize Iyamu of di APC wey be di kontri goment party and Obaseki wey just port comot APC wia im win di 2016 election enta di PDP. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53182089 +business Wetin be di New Zealand PM insult wey sell at NZ$100,000 for auction? "Dem don sell one signed copy of one transcript of New Zealand Prime Minister Jacinda Ardern dey insult one opposition leader don sell for more than NZ$100,000 ($63,200). Na microphone pick up di offensive comment afta one gbas-gbos exchange wit ACT party leader David Seymour. Ms Ardern later apologise for wetin she tok before OgaSeymour propose make dem two join forces to raise money for New Zealand Prostate Cancer Foundation. Di PM thank everybodi wey bid afta di the charity auction end on Thursday. During one lively parliamentary debate last week, Ms Ardern take issue wen Mr Seymour, leader of di right-wing libertarian ACT party, ask her to give an example of her ""dey make mistake, apologise for am properly, and dey fix am"". Ms Ardern defend her Labour goment record before she sit down and quietly tok: ""Such an arrogant prick."" Her microphone pick up di remark and dem preserve am for di official parliamentary record, Hansard, afta Mr Seymour ask for apology. But both of dem dey normally quarel wit each oda politically, dem come later decide to turn di affair to something wey dey positive. Dem both sign a copy of one transcript of di official parliamentary record wey include di comment before dem frame and auction am online. Di man wey im charity auction tell local media say im go still take loan to help am pay for di NZ$100,100 (£52,200) winning bid. Julian Shorten tell 1News say im dey happy wit wetin im buy and say: ""Dis na one moment for New Zealand political history."" For one statement, Mr Seymour say: ""Di interest big pass wetin anyone don ever dream of am. ""Wen I suggest dis to her, she immediately agree,"" im add. ""I dey blown away by di kindness of bidders wey dey help pricks everywia wit dia generosity."" ""I no fit say I expect dis,"" Ms Ardern post am on Facebook before im thank Oga Seymour say im be "" good sport"". Ms Ardern Labour Party win one landslide victory for di kontri general election for 2020 and di prime minister don enjoy high approval ratings for much of her two terms for office. But as New Zealand dey expected to go to di polls for late 2023, Ms Ardern dey come under increasing pressure. Latest opinion polls see her Labour Party dey lead di main opposition National Party." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyxe51ez9klo +entertainment Stefflon Don and Burna Boy, wetin dey pa? Plenti tok don dey ontop Stefflon Don and her relationship wit Nigerian singer, Burna Boy. From tok of if dem dey date to di break up rumours wey pipo dey share on social media, e show say kontri pipo dey interested for dia relationship. But di ogbonge question na, who be Stefflon Don? Stefflon Don (real name, Stephanie Victoria Allen) don dey sing officially since 2015. She start out to dey sing wit ogbonge American musicians like Jeremih and Lil Yachty before she sign to 54 London wey be label wey dem create for am. Her song 'Hurtin Me' wey she do wit French Montana enta Billboard Bubbling Under Hot 100 singles and e reach number 7 for di UK Singles charts. Di single also go platinum and sell over one million copies. You fit currently hear am for Boasty wey be collaboration wit Wiley, Sean Paul and Idris Elba. Di song reach number 11 for di UK Singles Charts. Di song don dey certified Gold for di United Kingdom as e don sell over 400,000 copies for di kontri. For di short time wen Stefflon Don dey di music scene, she don already get plenti accolades for di industry. Forbes put am for dia Forbes 30 under 30 list. She also don pass 1 billion streams wit 1 million subscribers for YouTube and over 640 million video views. She don also get NME and Mobo Award wit BRIT's Critics Choice and Sound Poll nomination. For 2018, she dey among di list of musicians wey dey di XXL's 2018 Freshman class. Even though dem born am for England, her family move to Rotterdam wey dey Netherlands when she dey 4 years old and because of dat she fit speak Dutch. She return to di UK when she be 14 years old to finish school for London. Stefflon Don recently release a new single wey she call 'Hit Me Up' as part of her Don Drop Wednesdays project. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49480511 +health """Coronavirus Coping"" & ""Covid 19 Treatments"" [WHO] Experts explain why coronavirus infection dey drop for Africa" One Panel of experts wey World Health Organization (WHO) gada togeda don list some number of factors wey fit make coronavirus infections dey drop for Africa. Coronavirus pandemic still dey worry for different parts of di world with many European kontries wey dey experience increase cases but dat of Africa dey drop. Di panel of experts, wey include WHO regional director for Africa, Dr Matshidiso Moeti, give different explanations to di different behaviour of di pandemic inside di continent, wen compared to di rest of di world. But Dr Moeti she warn say dem need to do more research to establish di true extent of Covid-19 inside Africa. More than 1.4 million confam cases of coronavirus na im dem don report for Africa with ova 34,000 deaths. About one million pipo don already recover. https://www.bbc.com/pidgin/world-54299513 +sports Algeria vs Nigeria - All you need know about di match William Troost-Ekong go miss Nigeria international friendly match against Algeria. Di Nigeria defender go miss di game sake of injury during dia 2-2 draw wit Algeria B team last week. Three-time African champions Nigeria go play Algeria on Tuesday. Dis two teams fail to qualify for di Fifa World Cup for Qatar wey go take place later dis year. Super Eagles lose dia play-off match to Ghana while Cameroon beat Algeria to collect di World cup ticket. So dis match na chance for dem to prepare well for di qualifiers for 2023 African Cup of Nation. Di 2023 African Cup of Nations go hold for Ivory Coast, wey dey west Africa. Dis na eviritin you need about di friendly game between Nigeria and Algeria Di match go happun on Tuesday night September 27, 2022. Di match go start by 8pm West African Time. Tuesday match na di second-ever friendly match between di Fennecs and di Super Eagles. Di two-time African champions win di first match for Austria for October 2020 by 1-0. Wen di two teams clash again for 2006 FIFA World Cup qualifying match for Oran for September 2005, di Super Eagles flog dem 5-2. Di game between Algeria and Nigeria go take place for Stade Olympique d’Oran. Apart from William Troost-Ekong, wey dey injured Nigeria no get injury concern for dis match. But sabi pipo dey expect changes to Head Coach José Santos Peseiro starting line up wey bin face Algeria team B last week. Goalkeepers: Francis Uzoho, Maduka Okoye, Adeleye Adebayo Defenders: Kenneth Omeruo, Chidozie Awaziem, Olaoluwa Aina, Calvin Bassey, Zaidu Sanusi, Kevin Akpoguma, Valentine Ozornwafor, Ebube Duru Midfielders: Wilfred Ndidi, Frank Onyeka, Alex Iwobi, Richard Onyedika Forwards: Kelechi Iheanacho, Moses Simon, Godwin Saviour, Ademola Lookman, Taiwo Awoniyi, Chidera Ejuke, Cyriel Dessers, Terem Moffi https://www.bbc.com/pidgin/articles/crgd88gvvg9o +sports Daniel James: Leeds dey close to signing Manchester United and Wales winger for club record of £30m Leeds United dey close to signing Manchester United winger Daniel James for a club record fee of £30m. Tori be say Leeds coach Marcelo Bielsa don dey monitor James since di Welshman move to Elland Road from Swansea collapse for January 2019. But James later join United dat summer and im don score nine goals for im 74 appearances for di Red Devils. Leeds bin dey think to make anoda move for am during last summer window but dem sign di Brazilian Raphinha instead. As things be now, James future for Manchester United no sure sake of di arrival of Cristiano Ronaldo from Juventus, dat na why Bielsa don go back for di 23-year-old. And e be like say dem don already agree fee for am, na just small thing remain now for di deal to dey complete. Di money go be club record for di West Yorkshire side, e go pass di 29m euro (£24.8m) dem pay to Valencia for striker Rodrigo 12 months ago. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58392913 +entertainment Netflix Fate: The Winx Saga: Five things you suppose know about di series Di Fate: The Winx Saga na Netflix original series wey start to dey show for di platform on Friday 22, January, 2020. Already pipo don dey tok plenti tins about am even as e be like say e go cause big disagreement between pipo wey watch di show and tv critics. Di show plot na about one girl Bloom, wey grow up for America, only to find out say she be fire fairy afta she bin burn her parents house. Bloom later join di Alfea College to take learn how to use her powers. Here be some tins you suppose sabi about di teen drama. We promise we no go spoil am. Fate: The Winx Saga na adaptation of one popular animation of fighting fairies wey dem dey call Winx Club from Iginio Straffi. Di Winx Club don even get Nickelodeon adaptation but many pipo think say Netflix na di one wey waka far from di source material. You no go see di vampires and witches wey you know, but di producer of dis drama, Brian Young na di same pesin wey produce Vampire Diaries. Apart from di whole premise of di show wey be like Harry Potter with female lead, di show use im characters to show say demsef sabi. When di main character Bloom, meet her room mate Aisha, immediately dem ask which Hogwart houses dem go put dem sef inside. Like most of di teen drama for Netflix, na mostly 20 sometins dem use shoot di drama wey be about teen fairies. In fact na only Sadie Soverall wey act as Beatrix, wey be Alfea student, be teenager at 19. Dem include Chilling Adventures of Sabrina, Riverdale, and Stranger Things. Even sef, di lead actress of dis series, bin dey act for Chilling adventures of Sabrina. https://www.bbc.com/pidgin/media-55753523 +entertainment BBNaija 2021: 'I neva get any new motor from fans' - Princess "Former Big Brother Shine Ya Eyes housemate, Princess don comot to clear di air on top new motor wey tori dey fly up and down say she don get. For social media post on Tuesday, Princess Francis reveal say di tori na fake news. She add say, ""we no know who start di tori or why but we just wan clear kontri pipo say make dem no mind am say na lie."" Na for di last elimination on Sunday, na im Princess comot from di big brther season six house after she bin no get enough votes to escape eviction. Princess bin show herself as she dey comot di house as she tok who she bin dey crush on for di house. Princess na 30 year old Taxi driver for Imo state wey fit don lead to dis current tori wey dey trend. She tok for her introduction say she go carry her full energy come di house and her hobby na to dey cook." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58247541 +business Budget: Five tins to know about Nigeria 2021 budget of N13.588 trillion wey di senate pass "Di two chambers of di Nigeria National Assembly don pass di sum 13.588 trillion Naira as budget for 2021 fiscal year. Dem pass dis budget during dia special plenary ahead of di Christmas and New Year break, as plenary go dey adjourned till 26 January, 2021.For October 8, President Muhammadu Buhari bin present di first estimate of di 2021 budget of N13.08 trillion to a joint session of di national assembly. Senator Stella Oduah say she dey impressed wella for di way di budget dey focus to address di issue of infrastructure for di kontri. ""...I believe say di Armed Forces, don dey highly considered for dis Budget and if security no dey for dis kontri, di whole of dis budget dey good for nothing."" na wetin Senator Sani Musa tok as dem pass di budget. Di upper chamber of di National Assembly pass di appropriation bill afta Jibrin Barau, chairman of di committee on appropriation, present dia report for di special session." https://www.bbc.com/pidgin/55400570 +business Nigeria don jail 15 oil tiffs, two collect two years self-contain inside prison "Nigeria corruption police - EFCC don send two oil tiffs to go take self-contain inside prison for two years. Na 15 of dem wey Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) cari go Federal High Court Port Harcourt court for illegal Oil Bukering for Rivers State, Southern Nigeria. While Justice A. T Mohammed sentence two of dem wit option of fine, di oda 13 chop fines of one hundred thousand naira. According to EFCC all of di convicts trouble wen Nigerian Army, 6 Division, Port Harcourt sojas catch dem sometimes in 2018 and 2019 for different locations inside Port Harcourt, Rivers State as dem dey distribute Automotive Gas Oil (AGO) using Trucks, Tankers, Escavator wit registration numbers YLA 112 ZV; YLA 110 ZV; MGN 22 XA; KPR 23 XA; LFA 403 XA, KPR 24 XA; BNY 490 XA; KPR 345 XA; MUB 807 XA; BGM 229 XA; YEN 423 XA; BKR 395 XA; KWL 60 ZA and an Escavator 320 CL CAT witout goment licences. Na on Tuesday, July 30, 2019 wey EFCC, Port Harcourt Zonal office cari dem go court, on one-count separate charge wey concern illegal dealing in petroleum products, wey dey againt Section 4(1) of di Petroleum Act, Cap P10 Laws of di Federation of Nigeria (LFN) 2004 and wey get punishment under Section 4(6) of di same Act. According to di charge wey EFCC publish, e say; ""Mohammed Abba, Adamu Usman and Babangida Audu on or about June, 2018, inside Port Harcourt, Rivers State bin distribute petroleum product (Automotive Gas Oil) withMack Truck wit registration number YLA 112 ZV, witout Licence and so dem commit offence wey dey against Section 4(1) of di Petroleum Act, Cap P10 Laws of di Federation of Nigeria (LFN) 2004 and wey get punishment under Section 4(6) of di same Act."" Justice Mohammed convict and sentenc Mohammed Abba, Adamu Usman to two years imprisonment with an option of fine of N100, 000 (One Hundred Thousand Naira) each, while the rest 13 (thirteen) defendants chop jail fine of One Hundred Thousand Naira (100,000.00) each. Dem include: Babangida Audu; Chijioke Ali; Muhammad Jamilu; Umaru Hussaini; Ahmadu Adamu; Muhammed Muhammed; Mahmud Girei; Abubakar Mai Nasara; Sadiq Ismaila; Sama'ila Njidda; Mahmud Abdullahi, Chima Onuha and Ismaila Balarebe. Di Judge also order say di petroleum products wey dem catch dem wit na Federal Goment go collect am. Oil bunkering wey be illegal refining and selling of petroleum products dey happun well well for Rivers State, Nigeria. Rivers State dey inside di Niger Delta region whre crude oil wey dey kontri dey use make money, boku well well. Most of di pipo wey dey do di oil bunkry dey do as hustle but e dey against Nigerian laws to do am witout license, na dis one follow for some of di environment pollution for di region." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49189065 +sports Gernot Rohr: Why NFF sack di German and replace am with Augustine Eguavoen? "Di Nigeria Football Federation (NFF) don sack Gernot Rohr as Super Eagles head coach and replace am with Augustine Eguavoen. For one statement di NFF release on Sunday night, dem tok say Eguavoen appointment to replace di German on interim basis. ""Afta one virtual meeting wey NFF Executive Committee get on Sunday, we decide say Eguavoen go work with Salisu Yusuf (Chief Coach); Paul Aigbogun (Assistant Coach); Joseph Yobo (Assistant Coach); Dr Terry Eguoje (Assistant Coach) and Aloysius Agu (Goalkeeper Trainer). Former Nigeria captains Augustine 'Jay Jay' Okocha, Nwankwo Kanu and Garba Lawal don dey appointed to provide technical and ambassadorial support for di crew,"" NFF tok for statement. Although, di NFF never release official statement on why dem sack di German citizen, many pipo bin don dey call on di football body to replace di coach sake of say di performance of di Super Eagles no be like before. Nigerians bin make a lot of noise wen di Super Eagles chop dia first beating as dem dey prepare for di 2022 World Cup. No be only di beating pain Nigerians, but na sake of say di team wey beat dem na Central African Republic and na for Teslim Balogun Stadium dem sama dem 1:0. Wen Super Eagles chop di beating, dem bin dey number 34 on di Fifa rankings and CAR siddon ontop number 124. One of di pipo wey call on NFF to replace Rohr na former governor of Abia State and African pillar of sports, Senator Orji Uzor Kalu. Kalu tok say di last five years for Super Eagles under Rohr na wasted years sake of say di Nigerian team dey struggle to qualify for African Cup of Nations and World Cup. E ask why dem never sack di German national. Afta Nigeria play 1-1 with Cape Verde for dia last group game of di 2022 World Cup qualifiers, di noise to sack Rohr bin increase from many quarters. Even though Super Eagles qualify, Nigerians bin dey fear if dem go fit perform well during di tournament if Rohr dey in charge as di coach. Former presidents of the Sports Writers Association of Nigeria (SWAN) also follow chook mouth for di mata. Dem say Super Eagles wey be three-time African champion dey give Nigeria worry every time dem get match with anoda team sake of say dem no dey perform well again. SWAN tell NFF to remove Rohr and appoint first class coach wey fit di Super Eagles. Na August 2016 NFF appoint Rohr to be Super Eagles coach and na im be di longest serving manager. Eguavoen na former Super Eagles captain and ex-manager. In 1994, na im be di captain wen Nigeria win di African Cup of Nations for di second time. Dem born am on August 19, 1965 for Sapele, Delta State. E begin im football career for ACB Lagos and e don also play for Gent. Oda clubs wey di football legend don play for na K.V. Kortrijk, Ourense, Sacramento Scorpions, Torpedo Moscow, and Silema Wanderers. Eguavoen na Super Eagles coach wen Nigeria finish in di third place for di Africa Cup of Nations for Egypt in 2006. Some of di clubs wey Eguavoen don coach na Silema Wanderers, Bendel Insurance, Nigeria U20, Black Leopards, Enyimba International, and Sharks FC." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59634443 +entertainment Kylie Jenner don get belle again? Dis na wetin we know Billionaire business woman, Kylie Jenner fit don carry belle again o! Dis na on top tori wey dey spread all ova social media. Tori be say, she and rapper Travis Scott na dem do di collabo to born sibling for Stormi Webster. Dis dey come as di make up mogul don tok several times say she go like born anoda pikin. But neither she or Travis Scott don address di rumour for outside. Many American tori pipo dey quote source wey dey close to di family. You go remember say when she bin carry di belle of Stormy, dem bin no tok pim until she born. Howeva, pipo for inside social media don dig find say she bin no post dis summer well-well wey dey unlike her. Dem also discover say when paparazzi catch am for outside, she bin dey wear big clothes up and down. Even sef, when speculations start to dey fly up and down on top pregnancy mata, she start to dey post more skimpy pictures like she normally go post. Howeva, her fans wey sabi di reality star on how she dey like show off different nails for social media, notice say all di new pictures she dey post feature di same nails. Anoda clue wey dey make pipo to think say she don take in again na sake of say when she post say she dey chop sushi, but raw fish bin no dey her order. Raw fish for sushi na something wey health practitioners dey discourage pregnant women to chop. Kylie Jenner and her and off boyfriend Travis bin born dia first pikin Stormi Webster for February 2018. https://www.bbc.com/pidgin/world-58270715 +entertainment BBNaija: Step by step guide on how to apply for BBNaija season 6 "Organizers of popular Nigeria reality television show, Big Brother Naija don open auditions ahead of di sixth season. Di new audition go start May 3 and end May 16 and dem say dis new season go get N90 million worth of prizes. For March dem bin introduce new twist wit early auditions wey bin dey strictly available to DSTV and GOTV users. Dem don tell di participants wey bin take part of di early editions not to take part for dis new audition. On di start of di auditions for di new season, Chief Executive Officer, MultiChoice Nigeria John Ugbe say: ""We dey strengthen our investment in quality content wit another season of BBNaija. BBNaija don become one of di most anticipated TV events across Africa and dis season promise to dey even bigger and more entertaining"". Wit weeks of plenti drama, romance, Friday night games and di popular Saturday parties, di Big Brother Naija reality TV don produce ogbonge celebrities since e start di first edition for 2006. Last year out of di 20 housemates wey enta di Big Brother house na Laycon emerge di winner of di Lockdown season. For now dem neva tok wen season 6 go start." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56947510 +health Africa coronavirus infection cases witness 20 per cent drop - See how e happun Africa Centre for Disease Control say di continent don witness up to 20 per cent drop for di number of new infections of coronavirus cases since di past one week. For beginning of August, Africa bin get more dan 15,000 new cases of Covid-19 per day. Today, di cases na less dan 10,000 per day. Kontris wit di biggest number of cases like Nigeria, South Africa, Kenya and Egypt don dey see less cases so di number wey dem dey report don reduce. But according to some sabi pipo dis fit no be beta news. Dem dey wonder weda na sake say di kontris no dey do enough tests. Many don abandon random testing, instead dem just face areas wia reported cases dey. Africa CDC add say make pipo neva ova jubilate forget dem sef no take precaution. E say communities must to shine dia eye well well to make sure say di virus no spread. Di CDC dey also worry about di increase in confam cases for Tunisia, Morocco, Uganda and Burkina Faso. East and North Africa still dey record increase for daily cases of Covid-19. Now Africa get more dan 1.2 million Covid-19 cases and more dan 28,000 deaths. More dan 900,000 pipo don recover. https://www.bbc.com/pidgin/world-53936179 +entertainment Davido #TuleChallenge: Winner of di Tule challenge go win 2 million naira "Nigerian artiste David Adeleke wey many pipo sabi as Davido don find new job give im fans wit wetin im call di #TuleChallenge. Di Tule challenge involve make dem copy wetin e do for inside one video wey im post for im social media handles on Tuesday, 28 December. He say di winner of di challenge go collect two million naira. All wetin dem go do na to mimick am, tag #TULECHALLENGE as e get why. Dis don scata internet as plenty of im fans don begin send dia own version of di #Tulechallenge. Di musician bin share di video on social media where im dey shout ""Tule jor, Tule Jare"" shortly afta reports make rounds say im and anoda Nigerian musician Burna Boy bin allegedly clash for one night club for Ghana. Viral video wey dey circulate dey show as Davido vex and other patrons dey try hold am. E no clear wetin spark di tension for di club but some eyewitnesses say Davido dey di club already dey party before Burna Boy show. So once den see Burna Boy too enter, dem suspect say tensions go rise sake of di two dey beef each other. Di following day afta di viral video, Davido fire some tweets wey make pipo reason say true-true yawa bin gas between di two Nigeria ogbonge artistes for Ghana. Apart from di video im drop, e also post plenty tweets say im go leave music, say for 10 years im don Dis na some of di things wey make pipo reason say true-true some yawa bin gas between di two Nigeria's biggest music artistes. Dis no be di first time wey some kain beef go dey happun between di two musicians wey also be paddy-paddy. While many pipo dey speculate say di beef between Davido and Burna Boy bin start since di announcement of di 2020 Grammys Award wey Burna Boy, African Giant dey nominated, but di real time wey every pesin see am na for May 2020. Tori be say di mata start with one foto wey Davido post for im social media of Im and Wizkid and tag am ""greatest of all time"", afta di post Burna Boy make mention of pesin wey no fit play football and na im papa buy am stadium. Burna for di post wey im don delete although no mention Davido name say e everytin im achieve na because im papa na billionaire. ""You no fit play football, everybody know say you know fit play football and you be embarrassment to di team. But your papa buy di football team"". Dis post, according to Davido, for interview, shock am as e bin no know say dem get quarrel. Di two stars also bin face each other for dia albums wey dem drop for July of dis year ""A Better Time"" by Davido and ""Twice as Tall"" by Burna Boy. For A Better Time track one wey be FEM, Davido mention Burna wen im tok say ""Tell Odogwu say we like to Party"", in reference to Odogwu and Like to Party, Burna Boy songs. While for di Twice as Tall song, Real Life, Burna reference Davido 2019 album, A Good Time wen im say ""But now I'm tryna ride, f**k a good time"". For September, Davido reference di beef for di interview say im don dey try to reach out to Burna Boy tay-tay and e dey happy for all im success." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55487828 +sports AFCON 2019: Oda kontris wey win for oda tins pass football . https://www.bbc.com/pidgin/sport-49042706 +sports Kobe Bryant: Anniversary of when Kobe Bryant die - Widow Vanessa Bryant pay tributes to him & Gianni Kobe Bryant, di basketball legend and im pikin Gianni wey die for helicopter crash for California for US, meet dia end exactly one year today. Kobe Bryant widow Vanessa Bryant don admit say to lose her daughter Gianna and husband Kobe for dat tragic helicopter crash 'still no feel real' for her one year afta. Vanessa, wey be 38 years, tok dis one for Instagram on Tuesday wia she reveal say she receive one beautiful letter from Gigi best friends, Aubrey, and caption am: 'My Gigi dey INCREDIBLE and I truly appreciate your letter. 'She loves you so much. I miss my baby girl and Kob-Kob so much, too. [heart emoji] I no go ever understand why/how this tragedy happen to such beautiful, kind and amazing human beings. It still no feel real. 'It still no feel real. Kob, we do am right. Gigi, you still dey make mummy proud. I love you!' Meanwhile Vanessa also share di letter wey Gianna best friends, Aubrey. For her letter, Aubrey write about Vanessa as a mother. She say: 'You do am right Mrs. Bryant, and we all dey eternally grateful to you.' She add say: 'My mind constantly dey think of your beautiful daughter. Her smile and attitude push me to be better. You go don heard dis, but if I ever become a mom, I hope my daughter turn out exactly as your daughter.' She also write say: 'She care. She knew when I dey get bad day and know just how to make it better. She bin dey generous with her snacks when I forget mine own. She leave notes for my notebook wey I cherish. She be incredible pesin.' Vanessa latest post dey come a week afta she share some throwback fotos to mark her eldest daughter Natalia 18th birthday. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55815727 +entertainment Maria BBNaija eviction: Pere, Liquorose, Queen & Michael reactions afta di Big Brother Naija housemate dey evicted "As Big Brother Naija season 6 cross halfway, viewers don already say bye-bye to some housemates. Di housemates don already spend five weeks out of di 10 weeks wey di show suppose run for inside Biggie house. On Sunday eviction, JMK, Sammie and Marie leave di house afta dem get di least amount of votes from di public. Out of di three housemates wey leave di house na Maria eviction 'choke' housemates and fans pass. Maria and five oda housemates wey be Sammie, Cross, Queen, Pere and JMK na di pipo wey di house bin put up for possible eviction. Di viewers save Cross, Pere and Queen. Dia decision shock viewers and housemates yesterday as di public save queen and evict Maria. Based on say dem bin see Maria as one of di strong housemates dis season. Some even bin see her for di top five, sake of wetin she don do since di show start. Even though she and Pere bin enta di house as wild cards. Wildcards na fake housemates wey Biggie introduce dis season for di show as twist but di house fail to identify dem, so dem remain to compete for di ultimate prize. Some viewers and housemates dey reason say Maria eviction na fake. But di truth be say no be fake eviction, her time for di show don end. For Queen, she dance and thank Nigeria and Africa for saving her. She say dey grateful, she add say she shock say dem save her. ""Right now my confidence dey ova 100."" She tok. Meanwhile Maria eviction hit Pere wey bin dey very close to her for di house. E cry afta she leave di house as im fellow housemates dey console am Up until Monday morning, during dia workout session for arena im still neva get himself . Na only am sidon ontop bench as e look like im still dem tink about last night eviction. Michael and Liquorose na di oda housemates wey Maria eviction affect. For Michael, wen Angel go meet am for room, im bin dey cry. “I dey shocked, confused for dis house. I know say na game but I know no why I care dis much. E tok. “I no know say e go dey dis hard,” Michael add put. Liquorose wey she and Maria dem call themselves besties inside di house cry wella for her friend. As Whitemoney, Emmanuel and oda housemates bin dey console her. Well as e be say she be one of di popular housemates dis season, many of di viewers chook mouth inside her matter. Andre Osose Ayomide Ojeabulu write say :“Make she getat. She dey form too much no respect for anybody.” For Sheyin Adamson: “Di eviction be like Shine ya eye.” Meanwhile Kassandra John say: “Her eviction shock me just like her different accent shock me.” While Doreen Ihedioha Osuala say: “Na audio fans she get. Na only noise dem sabi make dem no dey vote."" Maria na di ninth housemate to chop eviction dis season for di show wey start for July. Na only 17 pipo remain to compete for di grand prize of N90 million naira worth of prizes." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58383285 +health Coronavirus new variant: France, Germany, Ireland, Netherlands ban flights from UK, see odas wey dey consider am "Some European kontries don begin apply travel bans with di UK afta e tok say one new more infectious coronavirus variant dey ""out of control""for dia. Ireland, Germany, France, Italy, the Netherlands and Belgium, all dey suspend flights and travel, although di measures different. Dem go do one EU meeting on Monday morning to discuss response wey go dey more co-ordinated. Di new form of coronavirus wey dem dey call variant don spread fast for London and south-East England. Prime Minister Boris Johnson on Saturday introduce new tier four level of restrictions, im scrap di plan to relax rules over di Christmas period for millions of pipo. Top health officials say evidence no dey say di the new variant dey more deadly, or go react differently to vaccines, but e dey show to be up to 70% more transmissible. WHO say dem don detect di mutation for Netherlands, Denmark and Australia. Ireland goment announce say flights wey dey arrive from di UK would go dey banned for 48 hours at least from midnight, and ""in the interests of public health, say make pipo for Britain, regardless of nationality, no travel to Ireland, by air or sea"". Ferry crossings for freight go continue. Netherlands say dem go ban all passenger flights from di UK from 06:00 (05:00 GMT) on Sunday until 1 January. Pending wen dem go fit get ""greater clarity"" on di situation for di UK. Belgium dey suspend flights and train arrivals from di UK from midnight (23:00 GMT) Sunday. Prime Minister Alexander De Croo tell Belgian television channel VRT say di ban go dey in place for at least 24 hours and say na "" precautionary measure"", adding say ""we go see later if we need additional measures"". Meanwhile, Italy Foreign Minister Luigi Di Maio tok ontop im Facebook page say di goment dey about to sign measure to suspend flights from di UK. For Germany, one order from di ministry of transport say planes from di UK no go dey allowed to land afta midnight on Sunday, although cargo go be exception. Health Minister Jens Spahn say dem never detect di UK variant yet for Germany. France don suspend all travel links with di UK for 48 hours from midnight. E say dem go use di period to provide a more co-ordinated European response. Spanish Foreign Minister Arancha González say Spain also want co-ordinated EU decision ontop di mata. Austria dey also plan ban on flights from di UK, dem dey currently work out di details according to Austrian media. Outside Europe, Israel don announce say anybody wey dey travel from UK must quarantine for two-weeks for hotel facility wey dem go pick. Dem first identify am for UK, in di middle of October from one sample dem taken for September. Sabi pipo say e don show say di new UK variant dey spread faster dan di original virus - up to 70% more transmissible. But scientific details ontop di genetic changes, and how they fit affect di behaviour of Covid-19, no still clear. Although e no show say di new variant go dey more resistant to already-developed vaccines, di mutation involve di spike protein of di virus. Dis na di part wey dey help am to infect cells - and also di part dem design di vaccines to target. So although scientific experts don warn against false alarm response, dem also say e dey necessary to track di variant and try to stay ahead of di virus." https://www.bbc.com/pidgin/world-55386419 +sports The Best Fifa Football Awards: Mane and Salah dey di 2019 shortlist Reigning African player of di year Mohammed Salah and Senegal Sadio Mane dey among di players wey make The Best Fifa Men's Player 2019 award shortlist. For di ten-man shortlist, di two Liverpool players na di only nominees wey come from Africa Previous winners of di award Cristiano Ronaldo and Lionel Messi dey among di players wey make di list together with new Real Madrid signing Eden Hazard. Netherlands trio of Virgil Van Dijk, Matthijs De Ligt and Frenkie De Jong make di list for dia achievement for club and kontri last season. Players like Harry Kane and Kylian Mbappe na dem complete di ten-man shortlist for The Best Fifa Men's Player 2019 award. Football sabi pipo compile di shortlist based on di players respective achievements during di period from 16 July 2018 to 19 July 2019. Fans, journalists, national team coaches and captains na dem go vote for di three finalists. Fifa go reveal all award winners for The Best Fifa Football Award show for Milan, Italy on September 23, 2019. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49182855 +politics IPOB agitations plus oda things Atiku Abubakar tok about for 'Di Pipo Townhall' As di Nigeria presidential election dey draw near small small, political gladiators, presidential candiadtes plus dia political parties continue to dey go about to canvass for votes. From political gatherings, to debates, interviews and rallies, dem dey prepare for di 25 February election wia Nigerians dey expected to decise dia fates. On Sunday night, di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar appear for one live intercative programme wey one local tori pipo, Channels TV organise. From Asuu salary, Ipob mata, insecurity, economy to football mata di former vice president make some promises. Oga Atiku na one of di leading candidates wey dey try become Nigeria president- na 18 candidates dey eye di position. Wen di achor ask Oga Atiku wetin e go do about di issue of di Academic Staff Union of Universities (ASUU) wey dey always go on strike sake of dia demands for beta welfare, e say e go meet di to pay di backlog of salaries if dem am elect AM. “I go increase di funding level (of education) as against wetin dey currently obtained, no doubt about dat because I be firm and committed believer in education. “I get undertaken to say, ‘Whatever backlog – we go clear all di backlogs and make sure say you go back to classes and students go back to school,” e tok. Oga Atiku wey dey always hammer on di need to privatise national asset still dey insist say selling some goment assets to di private sector na di best ting for di kontri economy. Dis na wetin e tok wen dem ask am why e be like say e dey fixated on selling public assets wey dem build with taxpayers money. “I no dey fixated but I think say na di best for di kontri. I mean, make we dey honest with ourselves, we get four refineries and dem no dey work; I no know for how many years now and every year we budget money for overhauling di refineries wey no dey work; please make we give am to di private sector,” e tok. “For every great nation for dis world, you find out say na di private sector dey drive di economy, dem provide di jobs, dem provide di prosperity, and dem do everything, why our own go dey different? So, I no dey fixated.'' E insist. Di former vice-presidennt also promise to build football fields for publoic places acaross Nigeria to help di kontri nurture and manage talents. According to am, dis na di model wey Morocco wey beat Portugal on Saturday to become di first African kontri to reach World Cup semi-final dey use for development of dia sports talents. “Wetin you go see for Morocco eb say dem provide football playing fields for almost every neighbourhood. For every neighbourhood you go to for Morocco, small villages, towns, and cities, you go find say dem don provide public football playing fields. “You go see as young as primary school pikin dey play football early mor-mor before dem go to school and later for di evening wen dem return from school, I think we gatz encourage dat,” Atiku tok. On di issue of insecurity wey dey worry almost every corner for Nigeria, Atiku Abubakar, say e fit adopt di security system wey dem dey for di United Arab Emirates (UAE) to tackle di wahala. Atiku say di UAE system dey primarily based on adopting technology to monitor wetin dey happun across di kontri. E maintain say adopting di UAE approach by monitoring everybody movement go discourage pipo from committing crime. “Di security architecture wey I admire na di UAE security architecture and e dey primarily based on monitoring. You no go see policemen for uniform for UAE, you no dey see soldiers but virtually everybody naim dem dey monitor everyday and particularly if be visitor, from di moment you enta di kontri or go out, anywhere you dey go, dem dey watch and dat na di deployment of technology as far as security dey concerned. Di PDP presidential candidate also tok abaoaut im plan to tackle di agitations by separatists wey include di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) if e become Nigeria president for 2023. E say di demands of di pro-Biafra agitators no dey beyond dialogue and negotiation. “Di IPOB issue for di South-East dey basically, as far as my understanding dey concerned, about di realisation of Biafra. E dey possible for Biafra to be realised today? How? By negotiations or by going through another civil war, wey we no fit afford? “I believe say we should be able to negotiate wit di agitators from di South-East, as far as di issue of Biafra dey concerned. We believe wetin dem need more autonomy as far as dia sub-region dey concerned. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd19pnrkr29o +entertainment Kim Kardashian and Kanye West gbasgbos over North West Tiktok presence "American rapper, Kanye West don respond to Kim Kardashian latest statemnt on dia family palava. For di Instagram post e accuse im reality star estranged wife Kim, say she try kidnap im pikin on her birthday. E go off say, ""wetin you mean by main provider? America see as you bin try kidnap mmy daughter for her birthday wen you no provide address"". Oda accuse di former presidential candiate sama for im wife head be say, ""You carri security dey follow me for di house wen I dey play with my son, then accuse me say I tiff, I bin even take drug test afta Chicago party because you accuse me say I dey on drugs"", Kim Kardashian bin ansa her estranged husband, rapper Kanye West accuse say she allow dia pikin join Tiktok without im permission earlier. For Instagram post Kanye West bin ask say ""Since na my first divorce be dis, I wan know wetin I fit do about my pikin wey dem carry put for Tik tok against my will?"" For Instagram story statement, Kim reply say, ""Kanye constant attack on me for interview and sicial media dem dey pain pass any tiktok North fit don create"". She go on to explain say, ""As di parent wey be di main provider and caregiver for our pikin dem, I dey do my best to protect our daughter even as I dey let am express her creativity for di medium wey she like so far say adult dey dia."" Kim Kardashian bin scold her eight year old pikin last year December wen she go live for di app without permission. Kanye West don dey go interviews and come online to question why dia first pikin North West, dey on top Tiktok without im permission. As well as im accuse Kim Kardarshian say she no allow am enta her house to see im pikin or even attend one of dem birthday. E tok for one interview say, ""I bin go pick my pikin dem drop dem for dia mama house, na im my daughter ask me make I come see sometin for her room, but di security for di house say I no fit enta"". Kim say, ""divorce dey difficult enough got our pikin dem and Kanye busybodi to try control and manipulate di situation for outside dey cause make e pain everibodi di more"". She further add say she wan handle di mata with dia pikin in dem for private and dey hope say Kanye West go fit use im lawyer to solve any kasala wey dem get, peacefully. Na for April last year di former couple bin agree to joint custody of dia four pikin afta Kim Kardashian bin file for divirce from Kanye West for February 2021. Di couple wey bin dey married for seven years born North, Saint, Psalm and Chicago. Recently, di two of dem don start to dey date again as Kim don dey go out with comedian Pete Davidson and Kanye West dey date Julian Fox." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60265275 +sports Arsenal sign new deals wit managers Mikel Arteta, Jonas Eidevall "Arsenal men manager Mikel Arteta, and women manager Jonas Eidevall don sign new contracts wit di club. Arteta sign contract to extend im stay for di club reach di end of di 2024/2025 season. ""I dey excited, grateful and really, really happy today,"" di Arsenal boss tok. Arsenal on Friday break di news of di unique double signing wey happun for Emirate Stadium for dia website. Di Gunners boss say im plan now na to take di club to di next level so dem go compete wit well wit top teams. ""We want to take di club to di next level and to compete wit di top teams. In order to do dat, we gatz to dey play for champins league,"" im tok. Jonas Eidevall wey join di club form Swedish side Rosengard last summer, sign contract wit di club wey go reach di end of di 2023/24 season. Eidevall dey sign di new deal afta impressive first season for London, wia im take di Women Super League title challenge all di way to di final weekend. ""E go allow me continue to work for club wey I love so Much and be around pipo wey I realy, really like, and be able to achieve tins togeda,"" Eidevall tok." https://www.bbc.com/pidgin/sport-61296849 +business Ghana Fix The Country campaign: Ghana National Petroleum Authority reduce price of fuel by 8 pesewas "Dis be after dem direct oil marketing companies to place some 17 pesewas on fuel prices as part of COVID-19 levy which affect petroleum products. After meeting plus stakeholders, de NPA reduce de increase from 17 pesewas to 9 pesewas. NPA say dis price changes go take effect from Wednesday, May 5, 2021. Meanwhile, Online campaigners behind de #FixTheCountry campaign serve notice give police say dem go embark on street protest on May 9, 2021. National Petroleum Authority (NPA) for Ghana say dem reduce de price of fuel per litre by 8 pesewas. Fuel prices for Ghana hit one of de highest after pump prices reach $1.07 dollars per litre. De latest figures spark outrage among petroleum consumers who dey express disappointment through social media hashtag #FixTheCountry. One social media user Barnabas Nii Laryea wrote, ""I just buy 100gh petrol, de gauge no even move. Tomorrow I go walk to work #FixTheCountry."" De average price of fuel per litre around December 2020 Ghc 4.7 per litre, but now fuel prices hit Ghc 6.1 per litre. Per de current price increases, if one get modern car which dey consume about 65 litres of fuel to fill up de gas tank, dis dey mean be say consumers go pay extra Ghc90 to fill dema car tanks. Consumer who dey fill gas tank weekly for one month go pay extra Ghc360 to same amount of fuel. De online campaign against govmemt get some support from pro govment supporters who dey tweet plus de hashtag #FixYourself. Dis reaction no go down well plus some users who say e be insensitive to tell Ghanaians to fix themselves when govment leadership dey." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56988472 +sports Mino Raiola: Paul Pogba, Zlatan Ibrahimovic and Erling Haaland agent Raiola rubbish rumour say im don die "Reports wey say ogbonge football agent Mino Raiola don reportedly die afta im fall sick, no dey true as di man imsef don rubbish di rumour. Raiola agency say di agent ""never die"". Di football agent later tweet say: ""Current health status for di ones wey dey wonder, pissed off second time in 4 months wey dem kill me."" Raiola be representative of stars like Paul Pogba, Erling Haaland and Zlatan Ibrahimovic. Raiola bin land for hospital for Milan for January and undergo one delicate surgery but di nature of im illness no dey revealed. Di multi-lingual football agent work im way up from humble beginning to become one of di most influential figure in di world game, im bin broker mega-deals wey involve some of di most popular players. Im be representative to stars like Pogba, Haaland, Ibrahimovic, Romelu Lukaku, Mario Balotelli, Marco Verratti and Henrikh Mkhitaryan. Oga Raiola be 54 years. Mino Raiola na Italian football agent wey dey represent a number of well known players including Paul Pogba, Henrikh Mkhitaryan, Marco Verratti, Gianluigi Donnarumma, Matthijs de Ligt, Erling Haaland, and Mario Balotelli. Im also be di agent of former Czech midfielder Pavel Nedvěd for many years. Dem born oga Raiola for 1967 for Nocera Inferiore, Salerno, for southern Italy. Im bin move to di Dutch city of Haarlem one year later wit im parents. Raiola grow up for di Netherlands, im papa get successful restaurant business where im bin spend im younger years dey work as waiter. E bin start to play football for di youth team of HFC Haarlem, but stop for age 18 for 1987 to become head of di youth team. Afta e do player and administrator small, Raiola remain involve for di football world, but dis time as football agent. Raiola reported first independent big transfer be Pavel Nedvěd signing from Sparta Prague for Lazio afta im great performance for Uefa Euro 1996, where Nedvěd Czech Republic reach di final. For 8 May 2019, di Italian Football Federation bin ban Raiola from acting as agent representative for three months sake of reason wey dem no tok, and im cousin Vincenzo Raiola chop ban for two months. For May 10, di ban bin dey extended worldwide afta Fifa Disciplinary Committee gbab di Italian federation decision. For 13 June 2019, afta Raiola and im cousin appeal di original ban to di Federal Court of Appeal for Italy, dem win, dis make dem commot di three-month ban. On 22 January 2020, Raiola bin dey among some high profile football agents including Jorge Mendes and Jonathan Barnett wey threaten to sue Fifa with sake of dia plan to put cap on transfer payments. Raiola sabi speak seven languages: Italian, English, German, Spanish, French, Portuguese and Dutch." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61260166 +entertainment Sam Obiago: Daddy Sam popular Nollywood actor don die "Veteran Nollywood actor, Sam Obiago Aka Daddy Sam, don die. National President Actors Guild of Nigeria (AGN), Emeka Rollas Ejezie confam di news for social media and say; ""Another Sad Day 😭😭😭😭😭😭RIP Daddy Sam."" Di cause of di death of Sam Obiago no dey known as e be say Emeka Rollas no reveal am for im announcement. Oda Nollywood actors don begin react to di news of di death of Sam Obiago and mourn di veteran actor. Actress, Destiny Etiko dey shock to hear di sad news and post foto of di actor for her Instagram page wit di caption; ""Nooooooooooo daddy Sam."" Sam Obiago feature for Nollywood movies like; Tears of a King, Royal Appointment, Blood Brothers and oda popular films. E dey popular known for e role as King for movies. More dey come." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59766167 +sports Liverpool vs Man City highlights: Salah goal give di Reds victory for Anfield Mohamed Salah fine second-half goal give Liverpool victory ova Manchester City for Premier League on Sunday. Salah, wey bin score six-minute hat-trick against Rangers for Champions League, compose imself well to take down Alisson long pass. Di Egyptian striker collect di pass and dribble Joao Cancelo before im beat Ederson to score for inside 76 minutes. Liverpool put all di bad result behind for dis game against di reigning champions. Di game for Anfield bin give fans plenty to shout about from Man city disallowed goal to Jurgen Klopp red card. Na really high tension match wey di fans see from two of di best teams for England. Dis result mean say Liverpool dey eight point for table while Man City still dey four point behind league leaders Arsenal. First Half 14 Mins: No goals for Anfield yet. Man City get 63 per cent of di ball so far. Na typical City performance. 17 Mins: Robertson swings in im trademark cross from deep, di cross put Ake against Salah for di back post, and di City defender clear am Dat one one of di few times Liverpool don show for penalty City box since di match start. 23 mins: Liverpool dey press Man city now, but na inside dia own half. But City dey time dey to play counter attack. 26 mins:Liverpool now get 70 per cent possession in di last 10 minutes but di score still remain goalless. CLOSE! 32 Mins: Erling Haaland bin get chance to score for City but Liverpool goalkeeper save di ball. 37 Mins: So far for di game City get six shots on target while Liverpool get two. 39 Mins: ANOTHER BIG CHANCE! Again City open Liverpool defence, dis time De Brynne cross find Haaland head but di striker header no fit beat Liverpool goalkeeper. 45 mins: One minute added time. HALF TIME: 0-0 Second Half 46 mins: Di game don resume for Anfield. 50 Mins: BIG CHANCE for Liverpool, Ederson deny Salah from scoring di first goal. Disallowed goal for Man City side afta VAR check suspect foul for di build-up to di goal.. CLOSE! Di game bin burst to life within seconds. Liverpool immediately respond. Mohamed Salah chip di ball across to Diogo Jota but im head am over di bar from close range! As e stand Liverpool 0-0 Man City YELLOW CARD Fabinho na di first to go in di book as im chop down Ilkay Gundogan. Great save! Another crucial stop but dis time na from Liverpool's Brazilian, Alisson. Erling Haaland get im opportunity as im dey space, dead centre of di top of di box, but im snatches at am a little and Alisson fit push am away wit im right hand. 70 mins: One good spell from City now as Ilkay Gundogan once again break through di lines but Joe Gomez block im run. 72 mins: Kevin de Bruyne's cross, looking for Erling Haaland. SUBSTITUTIONS Darwin Nunez dey on for Roberto Firmino. Jordan Henderson replace Fabinho. Fabio Carvalho dey due to come on for Mohamed Salah but Jurgen Klopp, afta one quick word wit am, change im mind. na Harvey Elliott go off instead. GOAL - Liverpool 1-0 Man City Mohamed Salah score for 75 mins. Around 10 minutes to go for Anfield. City gbab di ball dey find di equaliser. Jordan Henderson put am behind for another corner. YELLOW CARD for Thiago as im slide in very rashly on Rodri and fiam straight into di book. Kevin de Bruyne get to di byline as City go straight up di other end. Im pulls am back but Virgil van Dijk dey dia again. Heading into stoppage time now. Pep Guardiola make a change. Julian Alvarez dey on for Ilkay Gundogan. Trent Alexander-Arnold swap in for Mohamed Salah for Liveprool too. Salah no dey happy about am. FULL TIME Liverpool 1-0 Man City One ogbonge victory for Liverpool and a blow to Manchester City, wey fall four points behind leaders Arsenal. https://www.bbc.com/pidgin/sport-63271110 +business Wetin to know about di 13% oil derivation money Nigeria goment share? "How oil producing states spend di arrears of 13% oil derivation money? Dat na di major question pipo dey ask afta Rivers state govnor Nyesom Wike make im revelation. Di govnor reveal say Nigeria President Muhammadu Buhari don approve and release di unpaid 13% derivation deduction since 1999 to all States for di Niger  Delta. Di tok bin come out as claim but BBC Pidgin reach out to oda states for di region to confam say na true. Oga Wike during one of im programmes for Port Harcourt say di payment of dis money by President Buhari na di major source of revenue for im projects. “Make I tok am for di first time. So many pipo dey ask wia i dey get dis money?' Make I tok am. Na from mister President,” e tok. E add say “Money wey dem never pay to di Niger Delta states since 1999 wey be di 13 percent deductions presido approve and pay all of us from di Niger Delta states.” Di derivation principle na say if dem dey collect natural resources for any state wey dey bring revenue, goment go give back a certain percentage of dat revenue back to dat State. Goment go den put di remaining money for di Federation Account wey dem go share to oda States, na so di law tok. Di 13% derivation fund dey come from di federation revenue to oil producing communities through di State goments as e dey for  Section 162 (2) of di Nigerian constitution. Di federal goment dey pay dis 13% derivation to oil producing areas as part of benefits transfer scheme for di oil resources wey dem take from di State and eight states currently dey benefit from di scheme Di states na Rivers, Delta, Akwa Ibom, Edo, Bayelsa states, Imo and Abia states. Di 13% derivation fund dey different from di 3% money wey dem dey give host communities for di Petroleum Industry Act from di oil company operating expenses (OPEX). Data from di National Bureau of Statistics (NBS) show say oil producing states for Nigeria share N450.60 billion from di Federation account through di 13 percent derivation formula for 2021. NBS data show say Abia, Akwa Ibom,  Bayelsa, Delta,  Edo, Imo, Lagos, Rivers and Ondo States receive di money. Delta State receive di highest amount with a total of N141.93 billion, representing 31% of di total revenue from di derivation account. Akwa Ibom receive N91.16 billion representing 20%. For di first quarter of 2022, di eight oil-producing states for di kontri receive N144.31 billion from di Federation account. ""On di 13% derivation,  Governor Okowa goment dey transparent, accountable on all financial dealings on behalf of di pipo,"" na so di Delta state goment tok. Di Niger-Delta state say di total amount due to di state from di 13% derivation arrears na N240 billion out of which di Federal Goment agree to pay in quarterly instalment for a period of five years. Oga Fidelis Tilije, Commissioner for Finance say contrary to di ""revelation"" by Wike, Delta State only receive N14.7 billion in three quarterly instalments of N4.9 billion each. ""Wit di agreed amounts settled, some states like Rivers approach commercial banks and discount dia own in full and collect am, but Senator Ifeanyi Okowa say im no go wan leave di next administration with a huge debt burden. So e decide to discount only N150 billion out of di N240 billion expected receivables but later cut am down to N100 billion, di finance commissioner explain. ""So far, we don get N14.7 billion in three quarterly instalments and we also don access N30 billion out of di N100 billion we apply for as bridging finance.” Bayelsa State govnor, Senator Douye Diri  for im reaction  say dem dey spend di 13% oil derivation funds mostly on infrastructure development. Senator Diri  add say di monthly allocations di State dey receive from di Federation Account always dey public through dia monthly transparency briefings so dem no get any tin to hide. E come explain say wetin di state receive as 13% derivation refund from di time of di previous administration dey come in instalments. Dis na afta dem don discount am but add say di amount no make much impact in terms of development. Governor Diri say di cost of construction for a difficult terrain like Bayelsa dey three or more times dan oda places. E say di cost of constructing one road project for di State plenty pass di budget to build three or four flyovers for some oda tates even for di Niger Delta. “For pipo wey dey tok about di 13% derivation funds wey dey due di state, I wan tok here say for one reason or di oda, we bin dey under-paid. “Wen we discover am, we follow due process from di state executive council to di State House of Assembly. ""We get di approvals and di funds come dey discounted. I no dey play politics with dis kain tin. “Anybodi  wey wan see how we use our money, our monthly transparency briefings for on our financial income and expenditure dey  available.,” di govnor tok. Edo State goment say out of  di N28 billion wey be di share of di State from di One trillion naira arrears of 13% derivation wey dey due to oil producing States, dem don only receive N2.1billion. Commissioner for finance, Budget, Economic Planning and Development Joseph Eboigbe explain say dem don receive three quarterly release of N700 million wey give a total of N2.1 billion and di Accountant General get di records. ""Our share na N28 billion,  di net go dey distributed over five years quarterly so dat go be 20 quarterly instalment releases and three don come so far and each na N700 million, N700 million, N700 million. How we spend dat money we get di records for anybody wey wish to see am."" e tok. Akwa Ibom State goment say all di amount wey dey due to di state and wey dem don receive dey duly reflected for di 2021 budget and supplementary budget for dat year. Commissioner for Finance, Nsikan Nkan for statement explain say for di current financial year, di expected refund from di subhead. E say e also dey clearly captured for di budget and di Accountant General report also declare di amount dem receive as refunds from arrears of di 13% derivation fund. Nkan add say even di budget for 2023 wey currently dey before di Akwa Ibom State House of Assembly also include di sum wey dey expected to come from di arrears refunds and dem capture an as ""Other Exceptional Income: 13% derivation revenue arrears."" ""Concerning di arrears of 13% derivation refunds, na di affected Governors naim discover and make di demand through dia officers for Federation Accounts Allocation Committee FAAC, and FAAC  agree with dem and calculate di sum wey dey due to each State. Nkan come ask di public to ignore any figure wey dey for various media platforms as dem no be true. E add say with di International Public Sector Accounting system (IPAS) wey di state goment don implement, e no dey possible for any unaccounted expenditure to occur. We go dey update dis tori wit more informate from oda states." https://www.bbc.com/pidgin/articles/czr4eg93mglo +entertainment Zlatan and DJ Cuppy: From 'Gelato' to blocking, to 'I no know am' "E be like say Gelato no sweet again oh? Recently interview comot wey Nigerian rapper Zlatan Ibile tok say im no sabi who DJ Cuppy be even as im confuse her name with actress Cossy. Dis one shock pipo wella on top say na two of dem folllow collabo for DJ Cuppy hit song ""Gelato"". Dis dey come afta di interview am about Florence Otedola, wey em dey also call DJ Cuppy Twitter post say say Zlatan block her for WhatsApp and Instagram and she no know why. Well Davido Personal Logistics Manager, Afeare Isreal fit don drop more update on top wetin cause di memory loss for Zlatan wia DJ Cuppy dey. According to post for Instagram, di DMW staff claim say, Zlatan no chop any money wey comot from di Gelato hit song. E also add say DJ Cuppy bin cari Zlatan go Abuja to help am with fund raising for her charity but no give am any money, accommodation or feeding. Video later surface for social media, wey Davido bin dey do live with Zlatan for di fund raising event and Zlatan confam say ""Shingbain no touch our hand."" Tori be say di event wey happun for November 2019, bin make ova 5,1 billion naira. Howeva e be like DJ Cuppy don respond to all di ginger di tori dem dey get as she post for Twitter say ""Super Story #freeCuppy""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55847203 +sports Roger Federer go team up with Rafael Nadal for im final match "Roger Federer final match go see am play alongside old rival Rafael Nadal for Laver Cup doubles on Friday. Di two of dem go represent Team Europe against Team World Jack Sock and Frances Tiafoe for London O2 Arena. Before dat match, Andy Murray go start di evening session in singles against Alex de Minaur around 19:00 BST. Federer, wey be 20-time Grand Slam winner, tok last week say e retire for di team event, wey starts on Friday. Di 41-year-old Swiss tok say e go dey ""wonderful"" to play alongside Spaniard Nadal, wey be 36 years and wey get 22 major titles. ""I no dey sure if I fit handle it all but I go try,"" Federer tok. ""Dis one feels a whole lot different. I dey happy to get im on my team and not playing against am."" Nadal tok say e dey look forward to ""unforgettable"" match with im rival against di American duo.\n\n""One of di most important, if not di most important player for my tennis career na leaving,"" di Spaniard tok.\n\n""At di end, dis moment go dey difficult. I dey super-excited and grateful to play with am."" Federer don struggle with knee problem and no feel able to play singles.\n\nIm last competitive match na defeat by Hubert Hurkacz for di last year Wimbledon quarter-finals.\n\nEurope take on a world team for di three-day Laver Cup, wia Italian Matteo Berrettini go take Federer place ova di weekend.\n\nFor Friday day session, Norway Casper Ruud go face Sock and Greek Stefanos Tsitsipas go meet Argentine Diego Schwartzman for singles matches.\n\nDi 21-time Grand Slam winner Novak Djokovic dey also on Team Europe, captained by Bjorn Bjorg.\n\nJohn McEnroe skippers Team World, wey also include American Taylor Fritz and Canadian Felix Auger-Aliassime.\n\nDi Laver Cup, wey dem named afta Australian great Rod Laver, na Federer brainchild and Europe don win all four previous editions of di event wey see total of 10 singles and two doubles matches.\n\nEach match win worth one point on Friday, two points on Saturday, and three points on Sunday, with di first team to earn 13 points wen declared di winners." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c1wnq44p7l2o +sports Tottenham vs Chelsea: Premier League prediction plus kick off time of weekend games "Chelsea go hope to continue dia unbeaten record for dis season wen dem play London rivals Tottenham on Sunday for Premier League. But di Blues results no be di only ting wey don impress BBC football sabi pesin Mark Lawrenson. ""I go say Chelsea na di best team I don see for Premier League so far dis season,"" na so Lawrenson tok. ""Not just for di games wey dem don play well and win, but also in terms of winning wen dem no play well too. ""I no dey sure say any of di oda teams get di chance to win di dat level yet."" Lawro dey make predictions for all 380 top-flight matches dis season, against a variety of guests. Dis week guests na Aqib Khan and Shaun Thomas, stars of BBC Three comedy Ladhood. Ladhood na Leeds-based coming-of-age comedy wey feature Liam, wey get flashbacks as a young boy as im bin deal wit situations as an adult in di present day. Aqib and Shaun play two of im schoolfriends, Tom Cragg and Adnan Masood. Aqib na Manchester United fan wey dey hope to see them back as serious title contenders dis season, afta a long wait. Shaun na Liverpool fan, mainly because of im brother. E tell BBC Sport say: ""I bin dey watch games with am and di first one wey leave in mark on me na di 2005 Champions League final. Ever since den, I dey obsessed wit Liverpool. Kick off for di Games na 3pm West African time. None of these teams don win yet, but na Newcastle I dey worry more about. Wen I look di way Leeds dey play and I feel say di results go turn around for dem soon, but dat no be di case for Newcastle. Magpies boss Steve Bruce dey under pressure already and dat go only increase if tins go badly for dem on Friday night. Lawro prediction: 1-2 Aqib prediction: If Newcastle score, den Leeds too go score - but I feel say wit 50,000 fans for St James Park, e go make di difference. 2-1 Shaun prediction: I bin write down 2-1 to Leeds but I go change my mind and go wit a draw, because Newcastle dey house. I see Leeds taking di lead, and dat go make Newcastle push on. 2-2 Wolves goal against Watford di last time na gift, even though dem bin play well for dat game. I feel say dem go pick up anoda win here. Brentford last-gasp defeat against Brighton last week fit affect small. Lawro prediction: 2-0 Aqib prediction: Wolves no really dey score many goal but dem be good team. Brentford moral high right now though, so dem fit collect something here. 1-1 Shaun prediction: Brentford so far dis season start well but I tink Wolves just start to get tins going. 2-1 Sean Dyche new contract na great news for Burnley. Dem need am more dan ever dis season, if dem go stay up. Di Clarets bin play well against Everton on Monday, just like dem do against Liverpool at di start of di season, but dem no get anytin out of either game. I feel say dat fit change on Saturday. Arsenal bin get dia first goal, and first win, against Norwich - but dis go be a very different game, and e go be a real test for dem. Lawro prediction: 1-1 Aqib prediction: Burnley go fit try to bully Arsenal but I tink di Gunners go- go through dat - dem really need a win too. 0-2 Shaun prediction: I know Arsenal beat Norwich but dem bin no dey convincing. I fancy Burnley here. 1-0 Liverpool get good week so far wit wins ova Leeds and AC Milan and I feel say dat run go continue here. Crystal Palace bin get good result last week wen dem beat Tottenham, but I feel say dia result go dey go up and down for a while. Lawro prediction: 3-0 Aqib prediction: I want Palace to win and I dey see good tins wey go happun under Patrick Vieira, but na huge ask for dem to go Anfield and stop Liverpool, wey all dia best players dey in form at di moment. 3-1 Shaun prediction: I feel say Palace go score but we go win dis one. Our defenders don return back and we strong for our house. 3-1. Manchester City don score 16 goals for dia three home games dis season and I no tink say Southampton fit stop dem. Saints gatz adjust to losing Danny Ings, but I no tink say dem go struggle dis season - I no just fancy dem to get anything out of dia trip to Etihad Stadium. Lawro prediction: 4-0 Aqib prediction: I dey hope for a Theo Walcott hat-trick but I know say e no go happun. 4-0 Shaun prediction: City dey play well at di moment and dem fit tear Southampton to bits. 4-0. Norwich don score one goal wit no points from dia first four games, while Watford dey on di run of three straight defeats. Lawro prediction: 1-1 Aqib prediction: Norwich no dey score enough goals to get anything out of dia games. 1-2 Shaun prediction: E dey hard to see Norwich winning at di moment. 0-1 Well, di Rafael Benitez revival still dey on for Everton - im bin change di team to spark dia fightback as dem beat Burnley. Aston Villa bin lose to Chelsea last weekend but dem bin look good for dat game for a long time - dem bin get plenty of chances for di first half. E go dey close, but I dey tip Dean Smith side to collect di points here. As good as Everton dey, we see as dem shake for dat game against di Clarets and I feel say Villa go give dem wahala. Lawro prediction: 2-1 Aqib prediction: Goals go dey for dis one. Everton don turn into machine under Benitez, although I feel say for James Rodriguez as dem no dey look im side. Im be beautiful footballer. 2-3 Shaun prediction: For some reason, I bin dey see 0-0. Everton dey look very good at di moment though, so I gatz go with dem to win. 0-2 Brighton v Leicester (14:00 West African Time) Everybody go dey expect Leicester to win these kind of games now, but I no tink say e go dey straightforward for dem at all. Brighton bin leave am late to beat Brentford last time out but dem dey form now afta dem win three of dia first four games. Lawro prediction: 1-1 Aqib prediction: I neva go for 0-0 yet, a bi? Goals go plenty dis weekend. 1-2 Shaun prediction: Brighton start dis season no bad but Leicester go dey too strong for dem. 0-2 West Ham striker Michail Antonio suspension for dis game na big blow for dem. I know Manchester United bin no too play well for dia midweek Champions League match but I no tink say e go stop dem from qualifying out of di group. Lawro prediction: 0-2 Aqib prediction: I hope say wetin happun against Young Boys go help United get back on track as dem suppose. 0-2 Shaun prediction: Antonio na big miss for West Ham, because im be big threat for dia team. I hate to tok am but United get real chance to win di league dis season wit di quality wey dem get for dia side. Cristiano Ronaldo go continue to score goals and Bruno Fernandes na baba wen it comes to making dem. 0-3 Tottenham bin fall hand last week as dem lose to Crystal Palace, and for me, all I see for dis game na Chelsea win. Dem dey enough to keep Spurs out, and dem get players wey go cause problems for field.. Lawro prediction: 1-2 Aqib prediction: Dem no be di most entertaining team to watch, but e hard to beat Chelsea now. 1-2 Shaun prediction: Chelsea dey very strong. 1-2" https://www.bbc.com/pidgin/sport-58600151 +entertainment Baba Ijesha: Princess testify as court admit video evidence for Olayinka Olarenwaju 'sexual assault' case "Di Special offences court for di Lagos state High Court don admit video evidence wey show how Nollywood actor Olayinika Olarenwaju aka Baba Ijesha dey allegedly assault one teenage victim sexually. Di court admit di evidence wey Lagos State Lawyer A.O Adeyemi present to prosecute di mata. Dis na as di court begin take witness testimony of pipo wey say dem get informate about wetin happen for di mata. Princess Damilola Adekoya wey everybody know as Princess d'Comedian na she come out as di first witness. Princess for her testimony tell di court how she meet Baba Ijesha for 2008 during one event wia di Yoruba Nollywood actor allegedly say e go like dey close to her. ""Baba Ijesha say im like me and between 2008 and 2012 we become close because Baba Ijesha dey keep in touch. ""My marriage get challenge for 2013 and afta den, Baba Ijesha tell me say im get similar problem for im marriage too. I even attempt to help resolve im marriage as e beg me say make I help am. Im begin visit me just like oda colleagues. ""Di first time im come my house na 2014 wen I collapse afta I do one major surgery. Coincidentally, Baba Ijesha dey around so im carry me go meet my Doctor. Im wait till I finish wit my Doctor wen im come accompany me go house. ""Im later beg say im go like baff for my daughter room but I no gree. I insist say make e go use visitors bathroom. Im later say im no fit go house say make I allow am pass di night. As pesin wey be my friend and wey just help me I give am access to visitors room. ""Na afta dat period I notice say my daughter wey be 7 years old at dat time come begin do badly for school. Nothing we no do to find out wetin happen but we no get answers. We even begin pray thinking say na spiritual problem. ""Na April 2021 wey I come put movie wey I do say make we watch as a family and Baba Ijesha dey inside di film. As my daughter see Baba Ijesha for di film, she comot say she no dey watch again. I come begin wonder why di girl go refuse to watch film wey I do. ""On April 15 I call my daughter say make we tok but she still no gree. Na later she come begin tell me everything wey happen. I no believe wetin I ear. Di tori give me shock wey I no even know how to react. ""Na later I summon courage tell my mama and few oda pipo wey bring idea say make we tok to Baba Ijesha and den mount CCTV so we go fit record wetin happen. Na di CCTV camera wey dey for sitting come still catch Baba Ijesha dey lick my pikin ear and hand. ""As we catch am im begin beg say make I no expose am. E even beg me to allow am commit suicide. E also say make I no involve press or police. Baba Ijesha lie down begin beg me but I no gree. I tell am say di law go take its course. ""Before den, I bin don call police in case we catch am and im wan dey violent. Police later come carry am go Sabo police station wia im make statement."" Di trial of Baba Ijesha go continue to on Tuesday July 27 wit di examination of more witness for di case. Baba Ijesha dey face three counts sexual assault charges against di teenage girl." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57974280 +politics We 'close' Seme border to fight smuggling - Buhari "Nigeria President Muhammadu Buhari say di reason for di partial closing of Nigeria border with Benin Republic na sake of di massive smuggling activities, especially of rice, wey dey happun for dia. Buhari give di reason during im tok-tok with di President of Benin Republic, Patrice Talon, during di Seventh Tokyo International Conference for African Development (TICAD7), wey dey happun for Yokohama, Japan on Wednesday. President Buhari, wey express great concern ova di smuggling of rice, say e dey threaten wetin e administration done achieve with dia agricultural policies. According to am, ""Now wey our people for di rural areas dem dey go back to dia farms, and di kontri don save money wey dem for spend to dey import rice with di kontri scarce foreign reserves, we no fit allow smuggling of di product on large scale like dat to continue."" The Nigerian President say di limited closure of di kontri western border na to allow Nigeria security forces develop strategy on how to fight di smuggling. Presido Buhari wey dey respond to di concern wey President Talon raise ontop how im pipo dey suffer because of di closure say im don take note and e go consider make dem open am again in di nearest future. Buhari add say im go soon call meeting with im colleagues dem from Benin and Niger Republics to decide correct policies to stop di kain smuggling wey dey happun for di border." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49504102 +politics Sanna Marin: Obasanjo, Gowon, Muhammed - Meet di leaders wey rule Nigeria in dia 30s "Dis week, Finland set record as 34-year-old Sanna Marin don become di youngest prime minister for di world. If pesin tink say dis no be ogbonge achievement, consider say Marin na woman, wey don dey serve as Minister of Transport and Communications for her kontri since June 2019. Some fit say ""well, dat na Europe, e go hard for am to happen for Africa"". Maybe. But e no need be like that. Dis fit be why one social media campaign for Nigeria wey dem call #NotTooYoungToRun start afta some pipo feel say di recent leaders wey Nigeria get, dey too old and because of dis, e hard dem to understand di millions of citizens wey dey under 30 years. Pesin wey no sabi history well fit begin tink say all leaders wey Nigeria don ever get, old pass 40 years but wetin history tell us dey different. Dis na three former leaders wey rule Nigeria in dia thirties. Dem born am on 19 October, 1934 Position: Third Head of State from 1 August 1966 - 29 July 1975 Dem born am on 8 November, 1938 Position: Fourth Head of State from 30 July 1975 - 13 February 1976 Dem born am 5 May, 1937. Position: Fifth Head of State from 13 February 1976 - 30 September 1979 On 31 May, 2018 presido Muhammadu Buhari sign di 'Not too young to run' bill into law, wey reduce di age to become president from 40 to 30." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50717387 +sports Afcon 2021: Crystal Palace boss Patrick Vieira say tournament deserve more respect "Crystal Palace manager Patrick Vieira don insist say di Africa Cup of Nations deserve more respect. Di Senegal-born former France international dey set to lose three of im players to di tournament wen e kick off for Cameroon on 9 January. Vieira tok dey come as tori bin dey say top clubs for Europe threaten say dem no go release their players for Afcon sake of say dem get concern over di tournament Covid-19 protocol. For one letter wey European Club Association write give Fifa, dem say dem no fit release players if di tournament go make dia players miss dia club matches. On Friday Cheikhou Kouyate dey named for di Senegal squad, while Ivory Coast also include Wilfried Zaha and Jordan Ayew dey part of provisional list wey Ghana announce. ""I respect and understand di passion and di importance to players to go represent dia country so I no go ever stop any player from going to play di Africa Cup of Nations,"" di former-Arsenal captain tok. ""I believe say di competition need to dey more respected - becos dis competition dey as important as di European Championships."" Im also challenge more European journalists to take greater interest in di event and appreciate exactly wetin e mean for di African continent. ""E fit dey important for you guys to cover di Africa Cup of Nations a little bit more and to go to Africa and interview pipo to really understand wetin e mean for every single one of dem,"" im tok. ""Wen you dey talk about Senegal I no tink say pipo go really understand if (Sadio) Mane or Cheikou Kouyate no represent dia nation. If more coverage of di competition dey I tink pipo go understand more how important e be for di African continent.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-59788833 +health Coronavirus: Wife of SA first patient don catch di Covid-19 disease "Di wife of di first coronavirus patient for South Africa don also test positive, which mean say di kontri don confam three cases, health ministry tok. Di couple bin visit Italy as part of a group of 10 but dia two children test negative. Dey confam di woman 39-year-old husband positive on Thursday and on Sunday, Health Minister Zweli Mkize tok say im speak wit am. ""E day in high spirit and jovial,"" Mr Mkihize tok. On Saturday, a 39-year-old woman wey return with di group from Italy also test positive of di coronavirus. ""We dey expect di result of di oda six group members who travel go Italy within di next 48 hours,"" the ministry tok for statement. Africa don get more than 30 cases of di coronavirus as Algeria bin dey mostly affected, wit 17 cases - 16 of dem for one family." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51792712 +entertainment Tiwa Savage, Teni, Ayra Starr, Tems, female Nigerian artistes wey fit headline 2022 Many female Nigerian artistes, especially di musicians dey rep Naija wlla wit dia talent and you no fit relegate dem where Afrobeats dey mentioned. Dis na sake of say over di years, dem don add dia own quota to di development of Afrobeats. BBC Pidgin don compile a list of some of dis female artistes wey go headline di year 2022. Dis list dey compiled after enough research on di number of airplays, award nominations, awards, performance, hit songs, features wey dis artistes get. And we also tok to sabi pipo wey dey into entertainment management business for Nigeriabefore compiling dis list. Di year 2021 na eventful year for Tiwa Savage. Di mother of one pikin work hard last year. And di Nigerian singer and songwriter song Sombedoy's Son wey she feature Brandy na hit. Tiwa Savage Water and Garri EP na success and despite say she dey involved for sex tape scandal, the artiste no allow am affect her music career. Somebody's Son bin top Apple Music Chart and Itunes Chart last year. She don show pipo say dis year 2022 no be wetin she won take play and her fans dey expect many more hit singles from her. Tems wey real name be Temilade Openyi don prove herself say she no go relent for dis year 2022 as 2021 dey very nice to her career. Many pipo vibe to her hit song Crazy Ting wey dey her EP If Orange Was a Place wey she release in 2021. She dey featured on Wizkid and Drake songs wey give am more popularity for 2021. Billboard bin name am Hip Hop Rookie of di month of October 2021. Wizkid feature am for inside Essence and di song reach number one for Billboard Adult R&B Airplay Chart. Di talented female artiste still dey cook more hit songs and her fans dey expect di bangers from her dis year 2022. Na she dey number three position for Boomplay Nigeria top rising artistes of 2021. For Nigerian music industry, Teni na one of di most hardworking artistes and 2021 na beautiful year for her music career. Teni bin release her album titled Wondaland in 2021 and some of di songs ontop am get beta reception from Nigerians. Di one she feature Davido ontop, For You, get massive airplays. Na Teni be di top female artiste for 2021 on Boomplay Nigeria sake of say na her song dem stream pass among female Nigerian artiste. Make una watch out for Teni for dis year 2022 sake of say she never finish to make bangers. Dis Mavin Record artiste wey come prepared. Her music career na success for 2021 sake of say songs wey she release last year na hit. She release her studio album 19 and Dangerous on July 30 and Bloody Samaritan na di biggest song for di album wey take am go places. Di song bin top Itunes chart and e also perform well on Spotify and Apple Music Chart. Na she dey number two position on Boomplay Nigeria fast rising artistes of 2021. Di year 2021 also make sense for Simi music career as na di year wey she release one of her best songs, Woman. Some artistes also feature am for dia songs and she bless dia beat with her angelic voice. Chike feature am on im song, Running, and di video get 34 million views on YouTube. Her concert, Can You Simi Now! Live with the Banjos, na success as many pipo attend am. Simi never dey tired and wit di way she dey word hard, she no go disappoint her fans for dis 2022. Fave na one of the artistes to watch out for in 2022 sake of say she bin serve music lovers better music for 2021 and she show enough energy say she no come industry come joke. Her song Baby Riddim get massive airplay wen she release am in 2021 and she no dey show any sign say she dey relent. We no fit end di list witout Teniola sake of say she also give us banger for 2021 and her songs top charts. Her song Ryde get massive airplays and good reception from Nigerians. Niniol bin receive Grammy Award certificate for di role wey she perform for Beyonce album, Lion King. Dis music queen don prove herself say she go give her fans more hits for 2022. https://www.bbc.com/pidgin/world-59897978 +sports Brentford vs Man United postponed: Why EPL postpone di game "Manchester United Premier League match against Brentford wey suppose happun on Tuesday night don dey postponed sake of Covid-19 outbreak for di Old Trafford club. Di league say dem take di decision ""following guidance from medical advisers due to di exceptional circumstances"" of di outbreak. Earlier, United bin shut down operations for dia Carrington training ground to reduce di risk of di infection. Di outbreak dey come just as di Premier League start dia busiest period of di season. Fixtures dey on Wednesday, Thursday, Saturday and Sunday dis week. Premier League reports 42 positive cases Covid-19 results last week. Forty-two Premier League players and staff test positive for Covid-19 last week. Dis na di highest recorded cases for di league over a seven-day period. Dat week, 2,295 tests dey carried out, and dem do 3,805 tests for di latest round from 6-12 December. Di latest report of 42 results na increase of 30 on di 12 positives dem report from 3,154 tests from 29 November - 5 December. Brighton v Tottenham match for Sunday don dey postponed afta Covid-19 outbreak for Spurs. Dem call off Tottenham Europa Conference League match against Rennes on Thursday because of di outbreak wey result to Brighton postponement. Also on Thursday, some Leicester players no travel go Italy for dia Europa League group game against Napoli because of positive Covid-19 tests. Brighton, Tottenham, Leicester, Manchester United, Aston Villa and Norwich don confam cases of Covid-19. United say positives cases among staff and players wey dem report on Sunday don dey confamed by PCR tests and di outbreak ""require ongoing surveillance"". All Manchester United players test negative before Saturday 1-0 win for Norwich, but some test positive before training on Sunday morning. ""Sake of di training dem cancel and how e affect di squad, plus di health of players and staff wey be priority, di club don request make dem rearrange di match"" United tok inside statement dem release on Monday. "" Aston Villa boss Steven Gerrard confam say some staff members and players"" don test positive but insist say ""majority"" dey negative. E add join say Tuesday game against Norwich no dey in doubt. Canaries boss Dean Smith say one of im players dey isolate but di rest of di squad bin test negative on Sunday. For Brighton, head coach Graham Potter say dem get ""three or four"" positive cases. For di Championship, Sheffield United match against QPR on Monday don dey cancelled sake of outbreak for di QPR squad. Before di postponement, Brentford boss Thomas Frank echo wetin Arsenal Mikel Arteta tok as e call for greater clarity from di Premier League ontop fixture changes sake of Covid- 19. Manchester City manager Pep Guardiola say e encourage im players to get vaccine booster. E also say dem dey ""Speak wit di players every day to dey careful. Stay healthy, wear masks and social distance."" Burnley manager Sean Dyche say im no dey ""preach to di players"" on vaccines, but Norwich Smith describe di Canaries as ""highly vaccinated"". Dyche add: ""We get players wey no dey fully vaccinated. Everyone get choice, personally I don collect all di three doses as I tink say na di right tin to do."" Meanwhile, di Premier League board take di decision to postpone based on guidance from medical advisors."" Di league say dem go rearrange di matches ""in due course"". Di statement add: ""We go continue to work closely wit di goment, local authorities and supporter groups, and we go respond to any future changes to national or local guidance."" However, from Wednesday, fans go need to show proof of double vaccination or a negative test to attend sporting events wit crowds of more dan 10,000 pipo for England. Dis one nclude Premier League games. Brentford don tok sorry to dia fans for di ""disruption"" but dem ""respect"" di decision, and add say di ""health and safety of both clubs' players and staff must always come first"". On Thursday, afta di introduction of new coronavirus rules for England to limit di spread of Omicron, di Premier League tell clubs to return to emergency measures, including social distancing and wearing masks. For inside one statement wey di league issue on Monday, e say di frequency of lateral flow and PCR tests for players and staff go increase. Last season, Newcastle United game for Aston Villa for di Premier League dey postponed afta ""major increase"" in Covid-19 cases for di Magpies' training ground. Later dat month, coronavirus outbreak for Manchester City cause dia Premier League match for Everton to dey postponed four hours before kick-off. Villa bin also fight Covid-19 outbreak for January, wey mean say no first-team players bin dey available for one FA Cup third-round defeat by Liverpool, while Premier League games against Everton and Tottenham also dey rescheduled." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59648055 +politics Ruga settlement: Na suspicion make pipo reject Ruga - Dele Momodu Popular Nigerian Publisher Dele Momodu don tell BBC Pidgin wetin im tink about di Ruga controversy. According to oga Momodu, pipo dey ginger because of fear and suspicion, wey dem get about di whole mata. Momodu also open mouth about President Muhammadu Buhari cabinet and di time e dey take am to unveil im ministers. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49048474 +politics Ekiti governorship election results: Map wey show how Biodun Oyebanji win Ekiti state guber poll Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC don announce di kontri ruling party candidate, APC, winner of di Ekiti state govnorship election 2022. Biodun Oyebanji poll 187,057 votes and win 15 out of 16 local goment areas for di state. Im closest rival, SDP candidate Segun Oni poll 82, 211 votes while PDP Bisi Kolawole get 67,457 votes. Di election happun on Saturday 18, June 2022 and Inec declare di winner around 3:00am on Sunday, 19 June. According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast. Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election). Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions. https://www.bbc.com/pidgin/tori-61851396 +politics Ministerial list: President Buhari say im no go allow anybodi to pressure am to release any list "Nigerian President Muhammadu Buhari tok at say even though Nigerians dey put pressure on am to release ministerial list, na those wey im know personally na im e go appoint. Presido tok dis one for one ogbonge meeting wit di leadership of di National Assembly for state house on Thursday night. Buhari say for im first term, all di ministers wey im work wit, im no know any of dem sake of say na di party and some individuals choose dem for am. "" I go take my time for dis second term to search for those wey I know personally to work wit."" ""Even though some pipo for dis dinner meeting wan see di ministerial list so dat dem go go dey leave in peace, I no go allow anybody dis time around to pressure me to release any list."" im explain Although President Buhari agree say im dey under pressure because of di list,e say im go take im time to search wella. President Muhammadu Buhari bin take oath of office for May 29 2019 but since den, e neva appoint im ministers dem. Nigerians bin don di expect di ministerial list afta di Senate President, Ahmad Lawan bin announce say di list go come out before dis week finish. But for dinner party, oga Lawan deny say im no tok like dat and dat afta senator Bassey Akpan from Akwa Ibom raise di point of order on di need for goment to release di ministerial list before dem go on break, im come assure dem say di list fit even comot dis week. E claim say im no give direct info on top di mata. Meanwhile afta di meeting, di presidency release statement to thank di leadership of di National Assembly and on top how dem di conduct demselves so far." https://www.bbc.com/pidgin/tori-48953706 +politics 'Bring back Wike', Uyo crowd and Atiku promise for PDP campaign flag-off Di main opposition party for Nigeria, Peoples Democratic Party (PDP) don flag-off dia campaign for di 2023 presidential election. Dem start days afta di kontri election body, Independent National Electoral Commission (Inec) open date for campaign, 28 September. Di PDP start dia campaign for Akwa Ibom, South South Nigeria on Monday wit many of di party leaders in attendance. As usual, crowd of supporters gada for di Godswill Akpabio International Stadium, Uyo to hear di promises of di party. Di presidential candidate of di PDP, Atiku Abubakar for di campaign for Uyo urge Nigerians to vote am to ensure good governance. E say make Nigerians return di party to power say dem get beta tins to offer di pipo. Oga Atiku base im campaign on four major tins; provide, work, unite the pipo, restore security and quality education. E tell pipo say to restore unity, to save di economy and to ensure security of the nation. “Today, we don start our campaign to rescue Nigeria from poverty, insecurity and bad governance. Dia fore I urge you to vote for the PDP. “I swear if you vote for PDP una pikin dem go return to school, una go get work, security go dey, unity go dey,” oga Atiku Abubakar tok. Di PDP start dia campaign without some of di govnors of di party wey dey vex. Govnors Nyesom Wike of Rivers state, Seyi Makinde of Oyo state, Okezie Ikpeazu of Enugu state, Ifeanyi Uwgwuanyi of Enugu state and Samuel Ortom of Benue no attend di campaign. Di G-5 as dem dey call dia sef and oda leaders boycott dia party presidential campaign flag-off based on di agreement say dem no go involve for di campaign until di party meet dia demand. Di govnors dey demand for di removal of di National chairman of di party, Senator Iyorchia Ayu. But di party get oda govnors including di four from di South south wey dey lead di campaign. “Election don change for Nigeria. Wetin happun for Osun state don show say Nigerians don tire for APC. Doz of us wey dey behind di scene for di Edo and Osun election don sabi how dem dey take run am. We know how to win,” South south govnors tok for Uyo. One chieftain of di PDP for stakeholders meeting of di party before di campaign for Uyo say di South South dey very important for di success of di party. Chief Tom Ikimi say e go make sense if di party fit go into di 2023 election wit di support of all dia govnors. E mandate all di govnors of di regions to make sure say dem bring back oga Wike into dia fold. Chief Ikimi say, “Di South south dey fundamental to di success of PDP and to di development of Nigeria. Time don come for us to take control of di goment of Nigeria. “Govnors play important role for election for Nigeria. I wan beg all di govnors of di South South to ensure say one of dem, wey dey Rivers state return fully back to di party. “Make all di govnors go visit Wike to let am know di decision of stakeholders na to bring am back to di PDP.” Di ruling party, All Progressives Congress (APC) no waste time to criticise di PDP flag-off campaign. Di Presidential Campaign Council describe di campaign as disaster wey dem predict. Minister of State, Labour and Employment, Festus Keyamo SAN say im bin don warn say di flag-off campaign na “disaster waiting to happun”. E say di party no tok wetin go do for Nigerians wen de menta power. “Speaker afta speaker just dey tok di same political jargons wey make many Nigerians dey wonder wetin dey happun. Oga Keyamo say, di fact say five PDP govnors no attend di campaign na sign for Nigerians not to vote dem for 2023. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c194e0ew814o +politics Ministerial list: Senate screen Akpabio, Amaechi, eight oda nominees "Nigeria Senate begin di screening of di ministerial nominees wey President Muhammadu Buhari submit to dem on Tuesday. Out of di 43 nominees, di Senate screen 10 on Wednesday. Uchechukwu Ogah (Abia), Goodwill Akpabio (Akwa Ibom), George Akume (Benue), Ogbonnaya Onu (Ebonyi), Emeka Nwajuaba (Imo), Olorunnimbe Mamora (Lagos), Olamilekan Adegbite (Ogun), Adamu Adamu, Rotimi Amaechi (Rivers) and Sharon Ikeazor (Anambra). Di first pesin to appear na Ukechukwu Ogah, e tok about diversification of di economy with Agriculture as major focus. Di nominee also ask di Senate to pass di Petroleum Industry Governance Bill as im make case for deregulation of di petroleum downstream sector in such a way wey e go work well to boost foreign exchange. But no be all of di nominees tok too much, di lawmakers give some di special privilege to take a bow and go without too much tok. Di ones wey enjoy di opportunity na Godswill Akpabio, Olorunnimbe Mamora, George Akume, Sharon Ikeazor, Emeka Nwajuiba, wey be current serving House of Reps member and Rotimi Amaechi, former minister of Transportation. While di lawmakers no too shake body for di odas, Amaechi own cause drama. Di President of di Senate Ahmed Lawan insist say make Amaechi take a bow and go, some opposition lawmakers no gree. Minority leader Enyinnaya Abaribe later insist say lawmakers from di minority including Rivers state get message for Amaechi. ""You go be minister of di federal republic of Nigeria wey include Rivers state, e mean say anything you fit do as minister to ensure say peace dey Rivers, abeg do am."" Na so Abaribe tok. Wen Akpabio show, pipo wey expect say drama go dey wen di minority leadr stand up to tok dey disappointed as im just tell am to take a bow." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49108387 +entertainment Ruth Kadiri birthday: Nigeria Nollywood actress Ruth Kadiri address birthday messages palava "Ruth Kadiri, Nigerian actress don address fans wey dey vex say she no respond to dia birthday messages to her. Di popular actress bin take her social media page to celebrate her birthday on Wednesday 24 March, 2021. But e be like say some fans wey follow celebrate her on her big day no get any direct appreciation response. She post video on her Instagram page on Thursday to address di mata say ""Every time na my birthday I get scared and my heart dey beat fast because I sabi say something like dis go come up Pipo go vex say dem wish me happy birthday and I no respond or my response no dey enough or dem go say I disrespect dem I get about 4.1 million followers and I no fit reply everybody So many pipo call me, text me, send me voice messages, and I still go work on my birthday, e no dey easy. If you wan show me love, show me love without expectation, whether I see your message or I no see your message e no mean say I no love you or appreciate you."" she tok for inside di video she post on Instagram. She also add: ""I no like am wen pipo tell me dem wish me Happy birthday and all you tell me na thanks and e get pipo wey I no even see dia own Pipo dey vex, pipo get angry, pipo unfollow you, pipo block you on petty things."" She say If pipo go wish am happy birthday and dem go still vex, make dem no wish her happy birthday say she no go vex. ""Love me unconditionally or no love me at all, we no go fight"", she conclude." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56526659 +business Russia-Ukraine War: Buhari don approve $8.5m to evacuate Nigerians from Ukraine Nigeria President Muhammadu Buhari don approve $8.5 million to evacuate at least 5,000 Nigerians wey dey stranded sake of di war between Russia and Ukraine. Dis 5,000 pipo go include Nigerians wey dey registered, plus di ones wey no dey registered, wey dey stranded for Ukraine. Di kontri Minister of State, Foreign Affairs, Ambassador Zubairu Dada, do di announcement on Wednesday afta di Federal Executive Council (FEC) meeting wey Vice President Yemi Osinbajo chair. Dada say di Ministry of Foreign Affairs and di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development do joint memo wey di FEC approve on di moni wey dem go use evacuate Nigerians wey now dey for Romania, Hungary, Slovakia, and Poland. E add say, three aircrafts, two from Air Peace and one from Max Air airlines, go run as many shifts as possible to make di evacuation of di pipo wey currently dey on ground possible. According to di minister, all di agencies dey fully ready wit all di resources to make sure say di aircraft leave Nigeria on Wednesday to begin evacuation. At di moment, about 1,940 thousand evacuees dey different embassies for neighbouring kontri wit Ukraine. And di authority say dem dey work hard round di clock to ensure say dem brink dem back to Nigeria safely. https://www.bbc.com/pidgin/60591357 +health Emmanuel Macron coronavirus: French president test positive for Covid 19 "France's President Emmanuel Macron don test positive for Covid-19, di French presidencyt office don tok. Di 42-year-old take test after experiencing symptoms and go now self-isolate for seven days, a statement from di Elysée Palace tok. Oga Macron ""still in charge"" of running France and go work remotely, one official tok. France dis week bin impose one overnight curfew to help deal wit rising cases of coronavirus inside di European kontri. E don reach two million confamd cases inside di kontri ince di epidemic begin, wit more than 59,400 deaths, according to data from Johns Hopkins University. ""Di President of di Republic don test alias diagnosed positive for Covid-19 today,"" di Elysée tok inside one statement on Thursday morning. ""Dis diagnosis happun as dem perform PCR test at di start of di first symptoms."" E no dey yet known how Mr Macron catch di virus, di president office tok, adding say im office dey identify those him been dey in close contact with to inform dem of di situation." https://www.bbc.com/pidgin/world-55331013 +politics Bayelsa news on supreme court verdict today: Now wey David Lyon don waka, see wetin go happun for di State "Hours afta Supreme Court for Abuja sack di Bayelsa State governor-elect David Lyon, just one day before im go take oath of office alias inauguration, wetin dey for pipo min now na wetin go happun next? Alreadi one of di organiser of Friday swearing in ceremony, Teddy Bai tell BBC Pidgin say true true ""dem don suspend plan of swearing in ceremony of David Lyon as di Governor of Bayelsa State."" But di National Chairman of di kontri goment party All Progressives Congress, Adams Oshiomhole don reveal say dem no go swear anybodi in as govnor of di state on Friday 14 February, 2020. Oshiomhole tok no mind say di five-man panel of Nigeria highest court now, don declare PDP candidate Douye Diri as winner of di 2019 Bayelsa State governorship election. At di time of dis tori, Nigeria election body Inec for Bayelsa tell BBC Pidgin say dem still dey wait for Supreme Court to give dem di judgement before dem go know wetin to do. Di new govnor elect Duoye Diri still dey wait to collect im Certificate of Return from Inec. So wetin go happun for Bayelsa now? For midnight of Thursday enta Friday 14 February, 2020 di tenure of Seriake Dickson wey be di current govnor of di state go expire. E suppose handover to di new govnor but as e be say dem don suspend am, according to di law for Nigeria na di Speaker of di State House of Assembly go takeover ruling of di State if swearing in no happun. Di APC chairmo also tok say e party go challenge di judgement for court. APC candidate David Lyon bin dey prepare for im inauguration as Govnor of di state wey suppose happun on Friday 14 February, 2020 before dis ruling from di Supreme court comot. Oga Lyon na candidate of di All Progressives Congress wey be di ruling party for Nigeria while Duoye Diri na di candidate of di main opposition Peoples Democratic Party." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51493133 +sports Black Stars test dia strength against five-time world champions Brazil Black Stars go today test dia strength against no other side than five-time world champions Brazil today. Dis go be de first of three friendly matches de West African nation dey play as part of preparations for de de 2022 Fifa World Cup for Qatar. De Black Stars friendly against Brazil be important sake of Brazil be South American side just like Uruguay who dem go face in de group stages. Uruguay knock Ghana out during de quarter finals of de 2010 Fifa World for South Africa, breaking de heart of de continent. De West African nation dey face dia arch rivals once again in de tournament dis year sake of that dem for make ready to face de South American side. In terms of statistics, Brazil dey outshine Ghana with five World Cup trophies under dia belt. De best performance from Ghana be to reach quarter finals, which to date be one of de best performances by an African side. Make we compare de performance of both Ghana and Brazil in dia last eight matches. Brazil win six games out of dia last eight matches, meanwhile Ghana win one game out of eight. Brazil play two draws out of de eight wey Ghana record four draws. In terms of losses, Brazil no lose any of dia last eight games but Ghana lose three games. Also, goals wey Brazil score be 20 while Ghana get 9 goals in dia last eight matches. Brazil dey ahead of Ghana in dis friendly, dem go fit boast of some of de best players in football. But Ghana dey hope say dem go rely on de new additions to de national team to enrich dia side.Star players like Inaki Williams wey dey play for Atletic Bilbao dey in de line up, Brighton Holve and Albion star, Tariq Lamptey switch from England to represent Ghana. Other strong players in de EPL like midfielder Thomas Partey, defender Mohammed Salisu, fast rising star for Ajax, Mohammed Kudus den others all dey in de Ghanaian side which go be threat to de Samba boys. For Brazil, dia encounter with Ghana be key to dia World Cup sake of dem for fit deal with Cameroon if dem want reach de knock out stage of de competition. De performance of de Black Stars apart from helping dem get ready for de tournament, go determine how much support de national team go get from Ghana after dem struggle in the recent AFCON and World Cup qualifiers. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw0g2dn2qpqo +sports Anthony Joshua vs Pulev: Tyson Fury, [how much did Anthony Joshua make] Prize money & fotos for AJ last fight "Anthony Joshua and Tyson Fury fight for 2021 discussion fit finish within a couple of days, Boxing Promoter Eddie Hearn tok. Joshua knockout Kubrat Pulev on Saturday and dis don open road for di fight between di two British boxers. Dem say negotiation go start on Monday and fit be di first fight for history for all four heavyweight titles. ""E no get any reason why we no go complete di deal and move on and solve di oda problems,"" na so Hearn tok. Tori be say many pipo dey tip WBC world heavyweight champion Fury installed as di favourite to beat IBF, WBA and WBO belt holder Joshua if dem fight next. Dem ask Hearn how long di discussion go take to complete di deal, Hearn reply say: ""A couple of days. ""We need to write to di governing bodies and say yes we get deal and we go now tok to di various sites and confirm di dates shortly for wetin I feel say suppose be di end of May."" ""I want di fight next. I no fit wait to knock am out,"" Na so Fury tok for video wey im post on social media on Saturday night. Anthony Joshua take home in di region of £10million after im comfortable win against Kubrat Pulev. Meanwhile see fotos dem of how Joshua kpo- kpo Pulev" https://www.bbc.com/pidgin/sport-55299028 +entertainment Eminem Music to be murdered by Side b album apologise to Rihanna "Rapper Eminem don apologise to fellow singer Rihanna afta one song wey leak see am tok say im 'side' wit chris Brown. Eminem apology dey come afta one viral video bin comot wia di singer wey e real name na Marshal Mathers bin allegedly tok say ""of course I side wit Chris Brown..."" Di lyrics of di song bin dey torchlight Chris assault on Rihanna for 2009. Chris chop arrest and even plead guilty before dem sentence am to Community service and compulsory anger management class. Eminem tell di Under my Umbrella singer inside di song Zeus wey dey di new album say: I apologise, Rihanna for dat song wey leak, I dey sorry, e bin no mean to cause you pain, e bin dey wrong of me. Di album wey follow January Music to be Murdered By come out on Friday. Wen di track leak last year, Eminem tok-tok pesin tok say: ""Dis na leak of something wey dey over 10 years old. Afta Eminem record am, im scrap am come rewrite am."" For e new track, Eminem admit say di original lyric ""dey wrong of im"". Eminem and Rihanna don collabo many times, including di 2010 US number one single Love the Way You Lie, as well as Numb for her 2013 album Unapologetic and The Monster from The Marshal Mathers LP 2 for 2013. Di rapper new album feature collaboration wit Dr Dre, Ty Dolla $ign, J Premier and Skylar Grey." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55369469 +health Covid-19 cases in Ghana today: Ghana record new strain of Covid-19 as infections rise catch 200 new cases daily "Ghana scientists discover new variant of Covid-19 after genomic sequencing show say de virus enter de country. President Akufo-Addo reveal say dem find de new strain inside passengers who arrive for de aiport. ""Recent genomic sequencing wey wana scientists do de prove say some passengers who arrive test positive for de new COVID-19 variant"" President Akufo-Addo reveal. Ghana health officials isolate de infected passengers but dem start dey do contact tracing among de general population sake of some of dem attend parties, weddings, funerals den tins wey dem no observe Covid-19 safety protocols. Coivd-19 cases for Ghana start dey see sharp increase as health officials dey record 200 cases daily. According to Prez Akufo-Addo, de number of patients who dey ICU rise from 18 to 120 who dey inside critical condition. Number of active Covid-19 cases for Ghana be 1,924, out of which de deaths increase catch 352 wey 33 patients dey inside critical condition." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55701058 +sports Leicester City vs Arsenal: How Gunners beat Foxes 2-0 for Premier League Arsenal beat Leicester City 2-0 for dia Premier League match on Saturday wit goals from Gabriel and Emile Smith Rowe. Arsenal start di game well wit some smooth passes wey worry di home team. And e no take long before dem score di first goal for di match from corner kick inside five minutes. Gabriel jump ahead of di player wey dey mark am to head di ball inside di net from one sweet cross. Arsenal second goal na Emile Smith Rowe score am afta Alexandre Lacazette bin dey load to shoot but di ball comot from am. And Leicester City defender Johnny Evans bin try to clear di ball but e no fit instead e set di ball well for Smith Rowe wey blast di ball inside di net. For now dis result mean say Arsenal don move up to fifth position for table wit 17 points while Leicester City dey number ten position for table before Saturday oda fixtures. Arsenal next match na against Watford for Premier League while Leicester City go host Spartak Moscow for Europa League on Thursday November 4, before dem play Leeds United on Sunday for Premier League. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59103951 +health Madagascar coronavirus cure: Wetin Africans dey tok about di herb "Africans don dey tok dia mind about di herbal drugs wey Madagascar claim say dey cure coronavirus. For social media, pipo particularly Africans, dey tok say dem go use di drugs if dem see am. Some dey even yab anybody wey go refuse am sake of say na herbal medicine. Last month, di Madagascan President Andry Rajoelina tok say di Malagasy Institute of Applied Research for di kontri don develop herbal medicine wey don cure two pipo of coronavirus. Local paper for Madagascar recently report say 55 patient don dey cured of coronavirus after dem use di herb. Tanzania, Guinea-Bissau and Comoros don already make plans to import di herbal medicine from di East African kontri. One Glam_byBerna wey im handle be @AmugeBernadett3 say make Uganda sef follow join kontris wey don import di drug. Another Kenya man, Kyalo Wa Makindi, tok say di drug na life saver and encourage make pipo endorse am. Oluwasheyi @SeyiRants from Nigeria even give gbosa give Madagascar ontop dis herbal concoction. ""Madagascar confam say dis herbal solutions wey dem bin use their brains do dey cure Covid-19. Dis one come make Africans to always believe in their resources as di #MadagascarCure don prove say there is no disease wey root and herbs no fit cure. Nigerian government! Over to you,"" na wetin im sef tweet. While some pipo bin dey urge Nigeria to join queue import dis medicine, some Nigerians dey tok say if di kontri try am, fake go follow full market. But World Health Organisation (WHO) don warn say make pipo no take drugs wey never dey thoroughly tested. Dis warning from WHO no stop some African kontris wey don order di Covid-organic drugs from Madagascar." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52622909 +sports Sadio Mane: Liverpool forward dey on isolation after positive coronavirus test "Liverpool forward Sadio Mane don test positive for coronavirus and e do self-isolation. Di tori dey come three days after di club say dia midfielder Thiago Alcantara don test positive for Covid-19. Liverpool say di Senegal winger dey ""show small symptoms of di virus but im dey feel good health overall"". Mane, play for di Reds inside di 3-1 win over Arsenal on Monday but im no dey di team for di EFL Cup defeat on penalties wey Gunners waya dem on Thursday. One statement ontop Liverpool website say: ""Like wit Thiago Alcantara, Liverpool go continue to follow all protocols wey relate to Covid-19 and Mane go self-isolate for di required period of time."" Mane, wey don score three goals for di Anfield club dis season, go now miss di Premier League game against Aston Villa on Sunday prior to di international break." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54398843 +politics Election Tribunal: Atiku wan carri 400 witness come court to testify against Buhari re-election Presidential candidate for Nigeria 2019 elections Alhaji Atiku Abubakar and im party Peoples Democratic Party (PDP) bin tell di Presidential Election Petition Tribunal on Monday say dem go carri 400 witnesses come for dia petition against Buhari. According to local tori pipo Punch, di plenty witnesses wey go show for di tribunal na to prove say no be Presido Muhammadu Buhari, and im All Progressives Congress party, win for 23 February election. Di candidate get 14 days to present all di witness dem plus present all di doucments. According to di five-man Tribunal wey Justice Mohammed Garba dey lead, di 14 days na wetin di first Schedule to do Electoral Act under paragraph 16(3) bin recommend. PDP main lawyer, Levi Uzoukwu (SAN), say even as dem say dem wan present 400 witness, dem plan to present even more. https://www.bbc.com/pidgin/tori-48830222 +sports Tobi Amusan: 'My papa burn my training gear' - Nigerian hurdler on road to 100m hurdles world record "Tobi Amusan don become world record holder and world champion for 100m hurdles, but she still remember how her papa burn her running gear. Number four position finisher for both 2019 World Athletics Championships and di delayed 2020 Tokyo Olympics, di Nigerian zeal don finally see her name in bold letters inside di track and field record books. Di 25-year-old run a time of 12.12 seconds! - deleting almost one tenth of second from di previous world record - for di semi-finals of di World Championships for Oregon before going to win gold for di final. However, e bin be like say di odds bin dey against her running career from di beginning. ""Both my parents na teachers, dem be strict disciplinarians,"" Amusan tell BBC Sport Africa. ""When you grow up for dat kain family, they feel say you suppose focus on school. And being a girl, dem tink say you go go astray, lose focus and all of dat. ""But becos my mama see wetin I no bin see mysef, she bin feel say she fit give me a chance. And she continue to tell me make I no disappoint her. ""My mama go tell my papa say I dey go church while I go sneak go practice or tell am say I dey go school for debate while I go for out-of-state competition. Na dia I begin. ""My dad bin really mad one time wen im find out [I dey running]. Im burn all my training gear and tell my mama say dat na di last time wey im wan s see me for stadium."" Fast forward several years, and tears of joy flow freely as Amusan stand on top step of di podium for Hayward Field on a historic day for Nigeria, wey see dem play di kontri national anthem for di World Athletics Championships for di first time ever. ""E neva sink yet, maybe di magnitude of wetin just happun go hit me later,"" she tok. ""I go out dia and put 100% in every championship and e no just ever dey enough. Every time na number four position finish. ""Den dis time my 100% no only be gold medal but na world record. Trusting myself just make everytin easier. I dey thankful to di man above for keeping me healthy. When God say na your time, na your time."" Her papa fit don doubt her, but Amusan bin always get plenty in her own ability. Back in November 2016 she tweet: ""Unknown now but soon I go dey unforgettable, I go persist until I succeed."" Dat message dey permanently pinned on top of her social media profile and provide summary of her rise to glory for Eugene. Yet her journey into athletics start as sometin like accident for Our Lady of Apostles Secondary School in Ogun state, Nigeria. ""I bin dey for football team, but I bin go just dey all over di pitch,"" Amusan say. ""My coach suggest make I go try out di track team and I became di fastest girl for di team, and dat na how I join di school relay team."" She from dia make di national squad for di 2013 Africa Youth Games for Nigeria, but she bin miss her place for di relay team but later win bronze for long jump instead. Competing over hurdles na anoda unexpected switch for Amusan journey to stardom, and na dia she truly break through on di senior stage. ""Di officials bin always dey pick who dem want for di relay team. Sometimes dem go say I no get experience so dem go pick who ever be dia favourite,"" she explain. ""E bin be a lot of pressure on a young athlete. I bin tink of quitting. I really bin wan travel wit di senior national team and some coaches tell me to try di hurdles."" Her tori continue to dey totori pipo from acround di world." https://www.bbc.com/pidgin/world-62299073 +politics Nnamdi Kanu latest update: Ohaneze Ndigbo want free trial for Biafra separatist "Di Ohanaeze Ndigbo Worldwide don break silence on Nnamdi Kanu re-arrest and trial. Dis be di first time since di pressure group dey tok since Nigeria goment re-arrest and re-arraign leader of di banned Independent People of Biafra [IPOB]. National Executive Council of Ohanaeze Ndigbo Worldwide issue communiqué afta dia meeting on Saturday July 10, 2021 for Enugu state. Ohanaeze stand for di position say make Nigeria goment try Nnamdi Kanu within di provision of di laws of di Federal Republic of Nigeria. Na so di communique tok. Di highest Igbo socio-cultural group wey dey represent all Igbo communities within and outside Nigeria say: Dem no dey against in trial but make goment treat di case in line wit global best practices. Dem say as part of dia determination to ensure free trial for Mazi Nnamdi Kanu, dem don arrange legal team. Di National Legal Adviser of Ohanaeze Ndigbo Worldwide and ogbonge Igbo leaders go monitor di legal proceedings, throughout di trial. ""Ohanaeze Ndigbo Worldwide don observe wit deep interest di recent re-arraignment and consequent trial of our son, Mazi Nnamdi Kanu."" ""Da in as much as Ohanaeze Ndigbo no dey opposed to di trial of Mazi Nnamdi Kanu, we want make dem try am within di ambit of di laws of di Federal Republic of Nigeria and in line wit global best practices."" Tok-tok pesin for di group, Chiedozie Alex Ogbonnia wey confam di communique give BBC. Ogbonnia say Mazi Nnamdi Kanu na dia son and dem feel wetin happun to am. Di arrest of Nigerian separatist leader Nnamdi Kanu don hand serious blow to e group, and fit even mark di end of e movement. Kanu as leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB), wey be group wey want breakaway state for south-east Nigeria, remain hero to manay. For more than a decade, im staunch radio broadcasts and social media posts bin be something wey Nigerian government frown at. But e transition to armed struggle for 2020 come begin look like step wey don go too far. Di armed department of Ipob - di Eastern Security Network - dey face accuse say dem kill at least 60 pipo in recent months. Most of dia victims na police officers, although di group deny di allegations. Nnamdi Kanu arrest dey seen as di final act by Nigeria government wey dey determined to stop di uprising. Di images of e arrest, more than anything else, go don seriously undermine di confidence of even e die-hard supporters. Dis no be di first time dem go parade di 53-year-old Jewish convert in handcuffs. But unlike previous occasions im customary resistance bin dey missing. Im days-old grey beard give am untidy look something wey even e Fendi designer clothes no fit hide. Some pipo don argue say Kanu turn di organisation into one-man show. Dis na as im shun some of e most trusted followers, and so now leadership vacuum don dey for Ipob." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57794916 +politics Court order Inec to resume voters registration ahead of 2023 elections Federal High Court for Abuja don order di Independent National Electoral Commission (INEC) to immediately resume Continuous Voters Registration (CVR) for 90 days before di 2023 general elections. Justice Inyang Ewko give di order on Tuesday 22, 2022 as e tok say na constitutional responsibility of di electoral body to make adequate provision for di exercise in accordance wit di Nigerian laws. For her judgement, Justice Ekwo also direct Inec to ensure say all eligible Nigerians no dey deprived of di opportunity to get di voters card for di general elections. Di judgement dey come afta one Anajat Salmat and three oda pipo sue Inec afta dem suspend di CVR. Di plaintiff argue say Inec no fit stop di voter registration contrary to wetin di constitution tok. Dem bin ask di court to order Inec to resume di exercise in accordance wit Nigerian law. Inec bin close di registration on 31 July afta dem bin first extend am. Afta di closure, dem say dem no go extend am sake of say dem don give Nigerians plenty time to register for di voters card and dem say anybody wey no do am go need wait until afta di 2023 general elections. Dem also tok say dem close di registration sake of say dem need focus on oda tins as any oda further extension go do complete damage to di preparations and timetable of di 2023 general elections timetable. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cydme7l5yq4o +politics Atiku, PDP don lose case for Supreme court to check INEC server Supreme Court don troway mata by People's Democratic Party and dia presidential candidate, Atiku Abubakar to fit torchlight Inec server. Di court troway di appeal wey Atiku and PDP carri come afta di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT) say dem no fit torchlight Inec server. Di election bodi bin say dem no get server, so no fit allow Nigeria main opposition party and dia candidate to check wetin dem no get. Di five judges wey decide di mata say ground no dey for dem to chook hand for di earlier decision of di tribunal wey bin reject PDP and Atiku request. Justice Centus Nweze wey read di judgement, say PDP and Atiku fail to show say di tribunal do wrong wen dem bin first deny dia request. Atiku and PDP bin claim for dia petition to di presidential election petition tribunal say di correct result of di February election wey dem say dem win, dey inside di Inec server. Dis server mata na just one part of case wey Atiku and PDP carri go di tribunal, say make dem rule say President Muhammadu Buhari and APC no bin win di election. Di tribunal neva give final judgement on dat case wey be di main koko. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49412245 +health School resumption updates: Rivers State goment deny closure of schools sake of covid-19 Rivers state goment don deny news wey dey make round say dem don order closure of primary and secondary schools for di states sake of covid-19. Di Commissioner for Education Rivers State, Prof. Kaniye Ebeku for statement wey im sign say di fake news na hand work of fraudsters and mischief makers wey wan mislead di public and cause confusion. Earlier, one statement wey di Permanent Secretary Ministry of Education, Sir Chidi Adiele allegedly sign bin come out say both private and public primary and secondary schools go shutdown on Friday 22 January, 2021 for two weeks and for students to stay for house till further notice and proper analysis of di Covid-19 pandemic. Di Commissioner for Education say dat na fake news, come tell teachers, pupils, students, parents and guardians to ignore di misleading information come add say dem go fish out di pipo wey do dis tin in order to bring dem to book, according to di law. Im come tell teachers, pupils, students, parents and guardians to ignore di misleading information. Di Chairman of di Presidential Taskforce, Boss Mustapha don draw ear give all schools for di kontri make dem strongly follow di non -pharmaceutical intervention as dem open dia doors to students. Oga Mustapha tok dis one during di weekly briefing of di PTF for Abuja, Nigerian Capital. E say di PTF bin don inform kontri pipo say dem go review di date for resumption sake of di number of cases of Covid wey di rise and sake of di shortage of oxygen. E say di PTF go kontinu to yarn wit di govnors plus di Federal Ministry of Education to monitor di situation. Schools across Nigeria resume today afta goment give di green light for classes to begin even as di kontri dey tackle second wave of Covid-19. Even as some states give go ahead, states like Edo and Kaduna say make schools still remain closed. But for states like Lagos, Ekiti, Rivers, Kano, Jigawa Sokoto, Abuja, students go back to school today. Although di second wave of Covid-19 palava bin make goment delay di reopening of schools, schools don resume as goment don give dem permission to reopen. Though di resumption witness very low turnout for some schools, yet some parents and students say dem dey happy say school don resume. For schools wey BBC Pidgin visit, dem enforce wearing of nose masks and washing of hands for di entry point, but dey turn back students wey no get nose mask. Some private schools switch to two sessions per day system wia some students go come school in di morning while others go resume in the afternoon to maintain social distance. But some goment schools no fit maintain social distancing for dia classrooms as di students jampack inside class. University of Lagos and some oda high institutions for Lagos dey dey use online schooling begin di new session. Ekiti State Government bin direct public and private schools for di state to re-open for di second term of di 2020/21 session from Monday 18th January 2021. Dis one na as goment also relax di curfew wey bin dey from 8 pm to 6 am. Restriction of movement now go begin from 10 pm and end by 6 am daily. Goment also say dem go begin testing of teachers and students in public schools across di state. Dem advise Private School Administrators to follow Covid-19 protocols, ensure di provision of gadgets and equipment for safety measures as schools wey no comply go dey closed down indefinitely. Primary and secondary schools for Delta State resume academic activities today in accordance wit di federal goment directive for schools to resume. But schools for Bayelsa and Akwa Ibom States resume last week Monday 11 January 2020 while schools for Rivers State don resume since 4 January, 2020 and dem dey do morning and afternoon sessions as a way to manage crowd for schools so dem go maintain physical distancing. All students and teachers dey expected to observe all Covid-19 prevention protocol wey include compulsory wearing of face-mask and for schools to make provisions for pipo to wash dia hands wit soap and water as dem dey enter di school premises. While students for Rives State University and Ignatius Ajuru University of Education don already resume since 4 January 2020, students for University of Port Harcourt go resume on 1 February, 2020. For Edo State, di state goment never tok wen schools go resume as schools dia no resume wit odas wey resume academic activities today. Some schools for Abuja and parts of Nasarawa state resume wit strict adherence to di Covid -19 Safety protocol. BBC Pidgin monitor some school across di two neighbouring states and students comply as dem wear dia nose masks to prevent di spread of di virus. For Gifted and Talented School, Karu Extension, dem make sure dem check di temperature of di students before dem enta inside di school compound. Di school also get wash hand basin for different strategic location of di school. Schools for Kano, Jigawa and Sokoto wey dey northern Nigeria don resume afta dem shut down late last year over covid 19 and insecurity. For di schools wey BBC visit for Kano state, di students say dem dey happy to come back school after dem spend di majority of last year for house. Our reporter observe say Covid-19 precautions no tight like last year wen schools resume for August and for Bayero University, plenti students show face though dem complain say nothing much happun as many lecturers no show face. Dis one na as di Nigerian Governors Forum on Monday say dem go meet on Wednesday to chook eye inside di mata of di second wave of di pandemic as schools dey reopen across di country. Inside statement by di spokesman Abdulrazaque Bello-Barkindo, di Governors forum say di way di second wave of di global pandemic take serious na cause of concern to dem. Nigeria number of new cases don rise in recent weeks, di kontri don cross di 100,000-mark for total infections. On Sunday, di Nigeria Centre for Disease Control report 1,444 new cases and 15 deaths. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55708574 +sports Wolves vs Aston Villa: How Anwar El Ghazi give Aston dia win for di Premier League match Substitute Anwar El Ghazi convert last minute penalty for Aston Villa to win dia West Midlands derby at Wolves. Wolves bin get beta home advantage since dia striker Raul Jimenez suffer skull fracture. Di two teams finished with 10 players as Douglas Luiz and João Moutinho collect red cards. Di tough game bin also get 11 yellow cards like say na holiday as di ball possession be 52% Wolves and 48% for Aston Villa. Now Wolves go face Chelsea on Tuesday (18:00 GMT), before dem go face Burnley next Monday (17:30). Villa go face Burnley on Thursday (18:00), den West Brom for anoda local derby next Sunday (19:15). https://www.bbc.com/pidgin/sport-55288420 +entertainment Megan Fox and Machine Gun Kelly: What you need to know about Colson Baker, di rapper di Hollywood actress fall in love with "On Tuesday, Machine Gun Kelly (wey im real name na Colson Baker) share selfie with Megan Fox , di couple wrap dia arms around each oda as dem pose with dia tongues out. ""I wait for eternity to find you again..."" na wetin im caption di photo wey im post for social media. Dis na di latest ontop di Hollywood couple relationship mata afta dia first joint interview together. For dia recent interview on July 22 for di Give Them Lala…With Randall podcast, both Megan and Machine Gun Kelly tok about dia romance wey first start for di set of di upcoming movie titled Midnight in the Switchgrass. ""Our trailers dey next to each oda so I go wait outside for my trailer steps everyday,"" na wetin Machine Gun Kelly tok. ""She get di most gorgeous eyes I don ever see."" Na wetin im add put Megan, wey recently separate from husband Brian Austin Green, say, ""Anytime wey me and am dey inside room and I greet am come look into im eyes. I know straight away say im be my twin. Two of our souls na di same I think. I tell am almost immediately."" Dem born Machine Gun Kelly wey im real name na Colson Baker for 22 April 1990 for Houston, Texas, United States. Colson Baker, wey pipo sabi professionally as Machine Gun Kelly, na American rapper, singer, songwriter and actor from Cleveland, Ohio. Im don release five studio albums throughout im career. As actor, Baker first feemwey im act na for 2014 romantic drama Beyond the Lights. Di singer get 10 year old daughter, Casie Colson Baker." https://www.bbc.com/pidgin/world-53583291 +politics Wetin Peter Obi tell me during im visit - Sheik Gumi "Popular islamic cleric Sheik Ahmad Gumi tell BBC News Pidgin wetin im and Labour Party 2023 presidential candidate Peter Obi discuss when di politician visit am for im residence for Kaduna on Monday. According to Gumi, di former Anambra state govnor come meet am about im ambition to lead Nigeria and e also give some advice like all oda politicians wey dem come see am. “Yesterday (Monday) na di first time wey I dey meet Peter Obi and e come to greet me and tok to me about im ambition to lead Nigeria. “E tell me di reason e visit Kaduna and di plan e get for di kontri.” “Like all odas I welcome am and I also give am some advice because wetin we want na pesin wey go lead well and unite Nigeria.” Regarding whether e don select pesin wey e like among all di presidential candidates, Gumi tok say na something e go like keep personal for now. “Of course di heart go get a preferred choice but I no go make am public, I wan keep am for my mind.” Sheik Gumi also tok say high profile politicians like Obi get huge role to play in terms of keeping di kontri united and for things to move smoothly. Obi visit to Kaduna co-incide with ruling APC presidential candidate Bola Tinubu visit for Kaduna Investment programme while opposition PDP presidential candidate Atiku Abubakar also visit to do rally. On im part, di two terms former govnor also post about im visit to Gumi on social media but e no give explanation as to wetin dem discuss. E just share fotos of di visit and caption am ‘Datti Baba Ahmed and me on courtesy call on Sheik Gumi for im house.’ Since di fotos show up on social media for Monday afternoon na im di visit of Obi to Gumi don dey generate reactions. Why some dey againt di move by Peter Obi, odas no see anything wrong for am. Wetin dey make pipo see Gumi as controversial na di kain connect wey im get wit bandits wey dey kidnap pipo for di northern region. Inside one inteerview with BBC Pidgin for 2021, di controversial Islamic Cleric reveal why Bandits wey dey kidnap pipo make am dia middle man. ""Bandits see me as clergy and someone dem fit trust as dey dem no trust goment or politicians."" ''Di bandits get confidence in me becuase of some of di things we dey tok here.'' Na wetin Sheikh Ahmad Gumi tell BBC Pidgin on Friday 7 May, 2021 wen e appear Live on Facebook. ''So many times goment don break agreements so need dey for a middle man. No parents don pay any ransom to di bandits,'' Gumi tell BBC. Since e declare im intention to run for president of Nigeria, Peter Obi don dey carry waka go visit many ogbonge Nigerians, from leaders to religious leaders. Among di pipo wey di Labour party don visit na Former president Olusegun Obasanjo, two former military head of states, Ibrahim Babangida and Abdusalam Abubakar. E don also carry waka go visit David Oyedepo, founder of di Living Faith Church Worldwide, aka Winners chapel. Sheik Gumi na one of di most popular Islamic clerics across northern Nigeria and di chief imam of Sultan Bello mosque for Kaduna state. Dem born am for 1960 when im father bin dey work for Kano state. Di man originally from Gummi local goment area for Zamfara state (northwest Nigeria) na also trained medical doctor.Gumi wey inherit preaching from im late father Sheik Abubakar Gumi bin serve for Nigerian Army before e resign. After e resign from Army e travel to Saudi Arabia to study where he obtain Doctor of Philosophy in Usul ul Fiqh (principles of Islamic jurisprudence). Gumi enter limelight few years ago at di height of school kidnappings across northern Nigeria when some of di gunmen entrust am to negotiate for release of di kidnapped. When bandits kidnap students from goment science college Kagara early last year na Gumi lead negotiations. Na same thing happun when bandits kidnap students from college of forestry and heritage university na same Gumi parents bin dey go meet to talk about dia children and dia freedom. On im part Gumi for past interview tok say di bandit trust am more than di goment na why dem dey allow am to tok to dem. Just recently Nigeria goment arrest im media consultant Tukur Mamu wey also be publisher of Desert Herald Newspaper over wetin dem describe as ‘security mata’." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c808g9jkenjo +sports How much each country dey collect for World Cup Football world dey bounce now as di highest soccer event di World Cup dey shele for Qatar. Morocco, Ghana, Senegal, Tunisia and Cameroon na di five African kontris wey follow go di tournament. Nigeria di acclaimed giant of Africa no qualify likewise Egypt wey produce di best player for Africa Mo Salah. Plenti enjoyment dey di tournament wey, aside di prestige wey di tournament dey give participating kontris and players, money also follow for FIFA package. We say make we share di breakdown of di kain money each kontri go collect for di tournament and di stages dem fit get more money. World football joinbodi FIFA bring out 440 million dollars as prize money for di 2022 World Cup for Qatar.\n\nPrize money for di 2018 World Cup na 400 million dollars while dat of 2014 na 358 million dollars. * 2.5 million for qualifying. Kontris wey qualify for di 2022 FIFA World Cup go get 2.5 million each to prepare and come for di tournament. * 9 million dollars for group stage. Kontris wey play and dey eliminated for di group stage of di World Cup dey entitled to 9 million dollars each. * 13 million dollars for round of 16. Any kontri wey qualify for di round of 16 wey be knockout stage but loose out, FIFA go sama dem 13 million dollars ontop di one dem collect for group stage. * 17 million dollars for quarter finals. FIFA also arrange anoda 17 million dollars wey dem go give to each kontri wey play for di quarter final stage of di tournament but loose out. * Di semi final.\nEvery kontri wey qualify for di semi finals dey sure of beta moni, but how big di moni go dey determined by which position you finally collect. FIFA ready oda awards for some oda categories for di World Cup. FIFA dey allow participating kontris make dem decide how much dem go give to each of dia players and officials wey come World Cup as salaries. World Cup winning kontri go collect di gold plated trophy plus medals. Though dem go return di trophy later and collect dummy copy for keeps. Second and third placed kontris go collect medals too. FIFA also make provision for 50,000 dollars worth of sports equipment for di kontri wey go win di fair play award. Dem go also collect FIFA diploma certificate. Di equipments na for football development for dia kontri. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c5162me50pyo +entertainment Burna Boy: See facts about Jo Pearl wey claim say she friend Stefflon Don 'boyfriend' "Ogbonge Nigerian artist Burna Boy dey face accuse for Instagram from one woman wey her name be Jo Pearl, she claim say she be im 'side chick'. Na December 1, Jo Pearl herself post di video wia she tok about her alleged 'situationship' with di singer. Although she no call Stefflon Don name, but tori be say Burna Boy and her Stefflon Don start to date for 2019. For inside di video wey be 15 minutes she give plenty details about her alleged relationship wit di singer. Burna Boy never respond to her allegations. Jo Pearl from London, she be 23 years old and she get Snatched by Jo Pearl, one waist trainer company. Her real name na Jo Pearl, wey she jokingly confam for her bio: ""Yes that na my real name."" She graduate from university for 2018 with Bachelor of Science degree with Honours for Psychology, something wey she share for her Instagram feed. Jo Pearl claim say she been date Burna Boy for around two years and explain say she dey make di video to let pipo know, She add say di ""hide-hide"" for two years dey affect her mental health. Jo Pearl claim say dem begin tok afta him dm her for Instagram. She describe am as pesin wey dey ""sweet and funny"" and say two of dem exchange numbers. She claim say di first time dem meet na for im pop-up event, and she say Burna Boy present dia situation as a ""love at first sight"" meeting. She claim say she ""basically moved in wit am"" before him travel to Nigeria for long time for shows, but she claim say dem continue to FaceTime and message each oda. Jo Pearl even claim say Burna Boy tok about marriage and kids wit her. She claim say she find out about him relationship for Instagram for January 2019, di tin make her collapse and ""cry well-well for days"". According to Jo Pearl, she see am for May last year but been get di impression say him relationship wit Stefflon Don na just publicity stunt. She also claim say dem no address di relationship mata when dem meet and begin run tinz like normal levels. None of her accuse dem dey confirmed, in fact Burna Boy neva tok pim ontop di mata." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55176940 +sports Yaya Toure say 'fans no get sense like before' na im make racism worse "Racism for football dey worse now because ""fans no get sense again like before"", according to former Manchester City midfielder Yaya Toure. Many incident throughout Europe don happun for recent months, and many of dem na big-big matches inside Serie A for Italy. ""I've chat wit Fifa because dis na very important something,"" di former Ivory Coast international tok. ""E go dey difficult because di way to win dis case go dey very long."" Im tok join: ""Fans, pipo, no get sense again like dem get before."" Last month, striker Mario Balotelli, Toure former City team-mate, para give fans wey shout racist abuse ontop am during match between Brescia and Verona. E say dem mind dey small and sense no dey dia head. Fans of Cagliari club begin do like monkey to provoke Inter Milan forward Romelu Lukaku earlier dis season, and recently, oga of Serie A bin apologise say dem use picture of three monkeys to take do anti-racism campaign. But racism sef dey English football, e just no plenty reach Italy own. Toure add: ""Of course e dey shocking because na 2019 we dey. For 2020, 2025 we go get young pikin dem wey don grow - wetin we go come do? You no fit continue like that.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-50853013 +entertainment Halloween 2021: Elozonam, Kim Oprah, Toyin Lawani, Stephanierock costumes wit style "Nigerians don carry dis Halloween celebration for dia head as di celebs wear costume for di day as well as di different parties wey happun to mark di event. Halloween na obodo oyinbo holiday wey include ojuju costume, and pikin wey go waka up and down to beg for sweet. E get influences from Catholic All Saints Day. No be today pipo don dey celebrate halloween for Nigeria on top say na time to jaiye. Di rapper and musician wey im real name na Femi Falana dress up for Halloween as villain of di Batman stories, di Joker. Di character na serious criminal wey dey dress as clown and dey rule Gotham city as di King of Crime. Actress Sophie Coker carry di Squid game mata on top her head as she and her pikin bin dress as one of di most iconic props from di series. Dem dress up as di girl doll baby, wey bin dey shout ""Red Light, Green Light"" for di first game of di series. Former BBnaija housemate, Elozonam also show im love for di day as im comot for not just one but two character. Like Falz, im bin also wear Joker custume but im also do anoda illan from Batman wey dem dey call, 2 face. Celebrity stylist, Toyin Lawani alsi remember celebrate di day as she dress as di Disney witch character wey dem dey call Maleficent. Social media celebrity wey dem call The Oditty currently dey Nigeria but dat one no mean say she no mark Halloween with style. Di content creator wey many pipo sabi as one of di lead creators for body positivity, dress up as di popular cartoon character for Avatar wey dem dey call banger. Anoda BBNaija celebrity enta social media with her own costume. Di star reveal say her outfit inspiration come from di Mortal Kombat character Kitana wey she remix as African Kitana." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59108660 +sports Deontay Wilder knock out Luis Ortiz to defend im WBC world title "Deontay Wilder knockout Luis Ortiz to defend im WBC world heavyweight title for di 10th time. Di American bin struggle for di fight as Ruiz start strong for dia rematch fight wey happun for Las Vegas. But for seventh round, Wilder right hand blow land Ortiz for ground. ""I find my measurement, I see di shot and I take am na wetin Wilder, 34 tok. Ortiz, wey be 40 years, manage to stand up but im no fit beat di 10 count. Im shock as Wilder bin neva do too much for di fight before im land am di blow. Dis victory mean say Wilder don move to dis level with Muhammad Ali for straight title defence win without defeat. Na only Tommy Burns (11), Vitali Klitschko (11), Wladimir Klitschko (18), Larry Holmes (20) and Joe Louis (25) don manage to defend dia heavyweight crown more times straight without defeat." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50535280 +entertainment Who be Femi Otedola first daughter Tolani Otedola, DJ Cuppy sister wey im buy Ferrari Portofino for "Nigerian singer, Tolani Otedola no really dey popular like her oda sisters, DJ Cuppy and Temi Otedola. She be di first daughter of Nigerian oil mogul and billionaire, Femi Otedola. Di 34 year old wey dem dey also call Olawunmi Christy Otedola na half sister to Temi Otedola and Florence Ifeoluwa Otedola, AKA DJ Cuppy. Nigerians bin take to social media to ask who Tolani be and why she no too dey popular like her oda sisters wen di picture of di Ferrari Portofino wey dia papa gift dem surface for social media. DJ Cuppy share di picture for her instagram page wit caption ""Papa take us shopping and buy us ONE for EACH"" Tolani sef take to her page to thank her papa for di 'stunning gift'. Tolani na graduate of di University of St. Andrews for Scotland, wia she study psychology. Before she move to di UK, Tolani bin attend primary school in Nigeria. She tok say na from school she begin get interest for music, For interview wit TVC Entertainment, she tok how she begin sing for church and later take am serious wen she begin write her own music. Tolani release her first single 'Tenderoni' featuring Nigerian Musician, Skales, for Dec 2017 and since then, she don get about four singles to her name. Her latest music na Badman wey she release for August 2020. Tori bin dey fly upandan one time say she dey date Nigerian musician, Reekado Banks, But she come out to deny di tori say She no dey in relationship wit Reekado but dem two bin do music togeda. Tolani dey always describe herself as pesin wey no really dey like socialise, one of di reasons why pipo no really too sabi about her and her music. Wen it comes to her family, Tolani say: ""Some of her earliest memories na di times wey she spend for her car with her papa playing loud music. I tink dat na one of di reasons I fall in love wit music"" she tok. Temi Otedola bin describe Tolani as her 'Best Sister' wen she celebrate her birthday on April 21." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54180624 +entertainment BBNaija Laycon na Youth Ambassador for Ogun State as Govnor Abiodun dash house, N5m cash give di Big Brother Naija winner "Laycon di winner of di 2020 Big Brother Naija reality show wey just finish receive 5 million naira cash donation and a three-bedroom bungalow from Govnor Dapo Abiodun of Ogun State, on Tuesday. Olamilekan Moshood Agbelesebioba wey be Laycon real name also collect appointment as Youth Ambassador of Ogun State wen di govnor host am for im Oke-Mosan office inside Abeokuta. Earlier Laycon receive special hailing from Govnor Dapo Abiodun of Ogun State, plus LIRS tax notice, just 24 hours afta di 26 year old win di star prize. ""I dey happy to congratulate one of our own in Ogun State, Olamilekan Agbelesebioba, AKA @itsLaycon for emerging winner of @BBNaija Lockdown."" Our Administration go continue to support and empower di youth through different channels, towards inclusion, job creation, and di utility of our natural youthful energy."" Di govnor add." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54438387 +politics Dawisu: Salihu Tanko Yakasai - What to know about Ganduje special adviser pipo hala say ‘miss’ "Less dan 24 hours after Salihu Tanko Yakasai wey be special adviser to Kano govnor on media post say APC goment don fail Nigerians, some pipo on twitter dey post say di father of 3 dey miss for over 14 hours. Dis no be di first time di govnor aide go use im twitter handle @dawisu to criticise goment, e chop suspension from work four months ago after e criticise president Buhari handling of di EndSars protest. BBC contact Kano Police Command tok-tok pesin DSP Abdullahi Haruna to know whether dem get report say Salihu dey miss but di officer say nothing like dat for now. ""We neva get any report say e dey miss for now."" Salihu papa wey be popular second republic politician Tanko Yakasai tell BBC say e just get information say im pikin dey wit DSS at di moment. ""Information just reach me now say e dey wit DSS at di moment and e no go pass issues with wetin e post on Twitter yesterday."" ""For now as a family we just dey wait to see wetin go happun, but I dey sure im oda brothers go make efforts to get in touch wit di authorities."" ""I don warn am to stop those im anti goment postings, even wen e post di first one wey earn am suspension, I tell am say if u wan criticise goment, leave your position and dey by di side, but as far as you dey di goment they will take serious offence."" Meanwhile Abubakar Sadeeq wey dey handle Kano state social media handles and website also confam on Twitter say Salihu dey with DSS at di moment. BBC try reach Kano state goment through Commissioner of information Muhammaf Garba but e know pick calls or respond to text message on di mata. Salihu Tanko Yakasai popularly known as Dawisu on twitter na Special Adviser on Media to DI Governor of Kano State. Im be former Director General, Media & Communications at Government House Kano. He also be di Founding Curator of Global Shapers Community of di World Economic Forum Kano Hub. Salihu Tanko na journalist by profession, former freelance reporter for CNN, writer for YPolitico & Ynaija online media platform. Im be Harvard Alumni and grassroot politician wit 2 decades of active participation. He also participate greatly for community development work. For October 2020, Kano state goment for Northern Nigeria bin suspend di media adviser after e criticise President Muhammadu Buhari for Twitter regarding di way e handle di #EndSARS protest wey dey happun for Nigeria. For statement wey Commissioner of Information for Kano Muhammad Garba release e say e dey important for public officials to dey very careful with wetin dem dey post online as e fit cause serious trouble. Recently, Di media aide bin enta twitter to criticise di ruling All Progressive Congress, APC sake of insecurity palava wey dey happun for di kontri and how goment dey handle am. Twitter user, Abubakar wey be di Kano State Official Website and Twitter handler confam for one tweet wey im post say true-true @dawisu dey for DSS custody. Nigerians enta social media to react to di alleged reports say di Department of State Security Service, DSS, gbab di Kano State Media aide." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56221153 +business Port Harcourt market fire: Marine Base plank market shop owners count dia loss as shops and property worth millions burn to ground "Fire outbreak for Marine Base Timber market Port Harcourt, Rivers state Nigeria don destroy properties wey worth millions of naira. Di fire start around 11.32pm on Wednesday 24 February 2021. Dis fire for di Marine Base plank shed na di third fire outbreak for Port Harcourt within one week. On Friday 20 February, fire burn some shops for Bishop Okoye Street for Mile Three Market and some butcher houses for Ogbumnabali area too. Some of di shop owners narrate to BBC Pidgin wetin happun. ""We no know wetin cause am. ""Billions don go, nobody comot anything. We call fire service pipo, dem no ansa us."" Na so one of di victims tell us. As at di time our reporter file dis tori, na di shop owners dey try quench di fire as authorities no dey ground. Anoda eyewitness say dem try dia best to quench di fire but dem no fit, dem call fire service twice, dem no respond. Nobody fit tok wetin cause di fire. Pictures from di scend of di market fire:" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56192622 +entertainment Miss Nigeria 2021: Shatu Garko make history as first hijabi to win di beauty pageant 18-year-old Shatu Garko don win di 44th edition of di Miss Nigeria beauty pageant. Garko beat 18 oda contestants for di beauty pageant wey hapun on Friday night for di Landmark Centre for Victoria Island, Lagos, Nigeria. Garko na di first hijabi wey go win di Miss Nigeria pageant. Nicole Ikot come first runner up and Kasarachi Okoro na di second runner up for di contest. Garko dey take ova from Etsanyi Tukura, wey come from Taraba State, di 43rd winner of di 2019 Miss Nigeria contest. According to di organisers of di pageant, di winner of di 44th Miss Nigeria wey hold on December 17, 2021, go go house with N10 million, 1-year residency for one luxury apartment, brand new car, and ogbonge brand ambassadorship opportunities. Di organisers of Miss Nigeria pageant say na every year pageant wey dey showcase positive attributes of Nigerian women. E dey for im 44th year now. Miss Nigeria 2021, Shatu Garko na from Kano State, she represent di north west zone for di competition. According to her bio for di competition, she be 18-year-old hijab model wey love horse riding. Garko don also bin celebrate for her Instagram page before about becoming di first hijab model to land one particular modelling job before. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59708774 +health Coronavirus update in Ghana: Why Ghana govment buy unit cost of Sputnik V vaccine for $19 instead $10 global factory price "Ministry of Health for Ghana justify reasons why dem decide to buy Russian Sputnik V vaccine for $19 instead of $10 wey be factory price. Dem come forward explain de reason after reports emerge from Norwegian newspaper, VG say Ghana go buy vaccines from one Sheik den another Norwegian who allegedly dey on wanted list of Police for money laundering. But Ministry of Health say dema reason for buying de vaccine at $19 be sake of dem enter de market after attempts to secure products directly from Russia govment fail. ""Sake of no response from direct channels den global shortage of de vaccine, MoH, on 9th March, 2021 respond to one offer from office of Sheik Ahmed Dalmook Al Maktoum of United Arab Emirates for supply of 3.4 million doses of Sputnik V vaccines at unit cost of $19,"" Kwabena Boadu-Afari, Chief Director for Ministry of Health explain inside statement wey dem release. Ghana order for 300,000 doses but Ministry of Health say dem no receive am yet, conditions dey for Ghana to opt out if dem no meet supply conditions. So far Ghana vaccinate some 1,230,000 people out of which 376,000 get de full Covid-19 dosage representing 1.2% of de total population who receive full vaccine. Although dis go cost govment $5.7 million, Ghanaian authorities say dem rather negotiate de unit price go down from proposed $25 to $19. Dem explain say land transport, shipment, insurance, handling den special storage charges be reason for de price de supplier quote. All dis deal happen at de time where Covid-19 shortage hit de world, despite dis global shortage dem still dey work to secure nore vaccines for Ghanaians. Ghana so far don record some 93,362 COVID-19 cases out of which 787 die of de disease, meanwhile recoveries dey stand 92,362 across de country." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57432831 +business Minimum wage in Nigeria: Trade Union threaten fresh strike as Muhammadu Buhari order immediate payment of N30k to junior civil servants President Muhammadu Buhari don press hand for goment to immediately begin pay di N30,000 new national wage for Federal Public Service workers wey currently dey earn below di new minimum wage. For mid-May 2019 Nigeria Federal Government set up committee wey go decide di kind of changes civil servants go see for dia salaries on top di new National Minimum Wage. Chairman of di National Salaries, Income and Wages Commission, Richard Egbule announce di Presido approval on Tuesday inside Abuja as im dey give tori ontop di latest progress of work wey dem dey do to begin pay di new national minimum wage. Wen dem go start to pay di approved payment na somtin wey office of di Accountant-General go decide and dem go rewind di time to wen di President sign di agreement. Na for November 2018 Buhari tok say e go send bill give di National Assembly on top di mata, by January 2019 di House of Reps approve 27k, while di Senate approve 30k by March 2019. According to Chief Egbule, di approval go take effect from April 18, 2018, and e go affect di salary of government agencies under five salary structures. As dis dey happun as Trade Union Congress dey insist say dem go mobilise workers to go on strike if goment fail to fully implement di approved minimum wage. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49013481 +entertainment Headies Award 2021 Winners list: Wizkid na Artiste of The Year, Omah Lay win 2020 Next Rated, Fireboy, odas win for di 14th edition Nigerian musician Fireboy win four awards for di 14th edition of di Headies, wey be music award show for Nigeria. Di musician win Best R&B Single, Best R&B Album, Best Pop Award and Best Headies Revelation to make am di artiste wey pack di most awards go house from di show. Wizkid win Artiste of di year and Viewers Choice Award. Di award show bin hold mostly offline to keep with Covid 19 restriction for Lagos, but plenti pipo still gada around di streaming platforms to see wetin happun. King Sunny Ade collect award as im join di Headies Hall of Fame. Oda stars wey win na Mayorkun, Omah Lay wey win Next Rated, Niniola and Simi. Best R&B Single Fireboy DML Best Recording of The Year Brymo Best Music Video of The Year 1 Milli - Davido By Director K Producer of The Year Pheelz - Billionaire by Teni Best Vocal Performance (Female) Niniola - Addicted Best Vocal Performance (Male) Praiz - Under The Sky Best Street Hop Artiste Mayorkun - Geng Rookie of The Year Bad Boy Tims - MJ Best Pop Single Nobody - DJ Neptune feat Joe Boy and Mr Eazi Best Collabo Ladipoe and Simi - Know you Best Alternative song Moelogo - I wonder Best Rap Single Falz - Bop Daddy feat. MS Banks Best R&B Album Fireboy DML - Tears, laughter and goosebumps Best Alternative Album Roots - The Cavemen Omah -Lay Viewers Choice Award Wizkid Songwriter of the Year Simi - Duduke Best Pop Award Fireboy - Apollo Lyricist on The Roll Ilbliss Goretti - Country African Artiste Recognition Award Master KG Headies Revelation Fireboy DML Best Rap Album God's Engineering - AQ Song of The Year Nobody- DJ Neptune feat. Joeboy and Mr Eazi Wizkid https://www.bbc.com/pidgin/tori-56142448 +entertainment Zlatan Ibile: 'I do bricklayer work before I blow' Nigerian musician Zlatan Ibile wey make di Zanku dance popular tori how e take enta music. E tell BBC Pidgin say e don do plenti tins for im life before im blow. Oga Zlatan don drop one album wey im call Zanku and EP wey im call RoadToCDK. E discuss some of im music process and also wetin im go do if dem vote am as Nigerian President. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55155782 +business Gas prices increase as Russia cut German supply "Gas prices don increas afta Russia further cut gas supplies to Germany and oda central European kontries afta dem draw ear wit warning say dem go do am early dis week. Europe gas prices dey up by like 2% trading above one earlier all-time high afta Russia invade Ukraine. Critics accuse di Russian goment say dem dey gas as political weapon. Russia don dey cut flows through di Nord Stream 1 pipeline to Germany, and now e dey operate at less dan a fifth of dia normal capacity. Germany dey import 55% of im gas from Russia and most of am dey come thru Nord Stream 1 - with di rest coming from land-based pipelines. Russian energy firm, Gazprom dey try justify di latest cut by say dem need am to allow maintenance work on one turbine. Di German goment, however, tok say no technical reason for dem to limit di supply. Ukraine dey accuse Moscow say dem dey do ""gas war"" against Europe and to cut supplies dey inflict ""terror"" on pipo. Di UK no dey directly affected by gas supply disruption, as dem dey import less dan 5% of dia gas from Russia. Howeva, dem go dey affected by prices wey dey increase for di global markets as demand for Europe increase. UK gas prices rise 7% on Wednesday so di price now dey more than six times higher than a year ago. However, e still dey well below di peak wey dey notice during di aftermath of Russia invasion of Ukraine. UK energy bills increase by £700 for April, and dey expected to rise again as one management consultancy dey sama warning say typical energy bill fit hit £3,850 a year by January, much higher than wetin dem forecasts early dis month. BFY tok say dia forecast reflect di increase in wholesale prices ova di past few weeks with di ongoing tensions with Russia wey dey increase concerns ova winter supplies. Di latest reduction in flows put pressure on EU kontries to reduce dia dependence on Russian gas even further, and e go likely make am more difficult for dem to refill dia gas supplies ahead of winter. Since di invasion of Ukraine, European leaders don do tok-tok ova how to reduce dia dependence on Russian fossil fuels. On Tuesday, di European Union agree to cut gas use in case Russia stop supplies but some kontries go get exemptions to avoid rationing. EU members now don agree to by demsef to reduce 15% of gas use between August and March. Howeva, di deal dey watered down afta e previously no get exemptions. Di EU don tok say dia aim from di deal na to make savings and store gas ahead of winter, warning say Russia dey ""continuously using energy supplies as a weapon"". Di voluntary agreement go become mandatory if supplies reach crisis levels. Di EU agreed for May to ban all Russian oil imports wey dey come in by sea by di end of dis year, but one deal ova gas ban don take longer. Since Russia invade Ukraine for February di price of wholesale gas don already go up, with serious impact on consumer energy bills across di world. Di Kremlin dey blame di increase in price on Western sanctions, insisting say dem be reliable energy partner and no dey responsible for di recent disruption to gas supplies." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw0jgq0lxzpo +entertainment Gideon Okeke : Why di Nollywood actor say e no wan act again "Nollywood actor Gideon Okeke, say im don tire, im no wan act feem again. Di actor enta im Instagram post say im dey get emotional breakdown and I wan stop acting. ""I dey get emotional breakdown. I wan leave acting, "" na so im lament. E say im don dey dey frustrated wit di profession even though im ""love am so much."" Most of Gideon lamentation na based on how tins bin be during di four months Covid-19 lockdown for Nigeria as pipo sidon for house no work, no money. During di lockdown, na only essential workers - like doctors, nurses, food producers and sellers - di goment allow to go work. But di Tinsel actor dey argue say, pipo for im profession too follow participate seriously to provide essential service during dat period becos dem help pipo keep dia mind sane as dem sidon for house witout doing anytin. ""Make I remind you say as you bin sidon for house for up to four months, dey watch Television, di actor participate actively to help you keep you sanity in check. Di na Essential Service if you ask me. Oga Gideon seriously question why e be say actor work na monkey dey work. According to am, despite all di work wey actor dey do, at di end of di day na only di moni wey dem dey pay am once na im e go get and ""most times, na small small di pay go dem drop to cover for a lifetime… For life! ""why e dey right for ACTORS to NOT collect royalties and residuals for dia work for Nigeria,"" im ask, ""Wetin di Guild dey do?"" Most professional dey entitle to pension and gratuity but Nigerian actors no get anytin like dat and dem no dey collect royalties. Gideon na Nigerian actor, model and TV presenter. Im become popular afta im contest for di first edition of Big Brother Nigeria for 2006. For 2008, e join di MNET TV series Tinsel. Im don dey act for Tinsel since den reach now." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55149841 +entertainment Brit Awards 2022: See how celebrities turn heads wit dia outfit for 2022 Brits Award red carpet "Celebrities turn heads for di red carpet of di Brit Awards ceremony wey happun for di O2 Arena , London on Tuesday night. Di 2022 Brits na awards ceremony wey dem organise to recognise di most talented artists for UK and to celebrate achievement within di music industry. Plenti artiste show for di red carpet as many of dem wear cut-out-black dress, or at least a version of am. Packed award ceremonies dey mostly feel like novelty, and di chance to dress up na also opportunity for celebs to be daringly on-trend, Dem wear wetin Vogue call an ""undeniably sexy aesthetic"". See how dem glam-up: Maya Jama' outfit remind us of Cher's famous Oscars outfit of 1986. Di presenter dey welcome award nominees during di red carpet show. How Singer, dancer and Pussycat Doll Ashley Roberts show for red carpet of di Brit's. Singer Anne-Marie look fierce inside di cut-away top she wear under her tailored jacket. Actress Jaime Winstone accessorise her outfit wit colourful ostrich feathers and also she wear matching eye make up. Singer Lola Young for di red carpet. Adele also dey fully in black, but she go for a classic, old-school glamour look wit nude nails and her hair sweep off ontop her shoulders. Oti Mabuse dey shine in gold, wit her dress dey feature frills and tiny straps. Ed Sheeran give us one huge pop of bright blue colour as im wear velvet suit. Joy Crookes wear one delicately stitched matching hood wit her ornate gold outfit. Doctor Who star Jodie Whittaker also show face for ed carpet in orange and white. Little Simz bin go for a cool but casual look, wit chunky-soled shoes plus red sunglasses. Trigger Point and Line of Duty star Vicky McClure wear one striking grey corset-style top wey she wear wit trousers. Eurovision winners Maneskin - pronounced Mon-e-skin - wear a candy-colour mix of latex, frills and ruffles. Album of the year Adele - 30 Dave - We're All Alone In This Together Ed Sheeran - = Little Simz - Sometimes I Might Be Introvert Sam Fender - Seventeen Going Under Artist of the Year Adele Dave Ed Sheeran Little Simz Sam Fender Best group Wolf Alice Coldplay D-Block Europe Little Mix London Grammar Song of the Year Adele - Easy On Me A1 & J1 - Latest Trends Anne-Marie, KSI & Digital Farm Animals - Don't Play Becky Hill & David Guetta - Remember Central Cee - Obsessed With You Dave ft Stormzy - Clash Ed Sheeran - Bad Habits Elton John & Dua Lipa - Cold Heart (Pnau Mix) Glass Animals - Heat Waves Joel Corry, Raye & David Guetta - Bed KSI - Holiday Nathan & 220Kid & Billen Ted - Wellerman Riton, Nightcrawlers & Mufasa - Friday Tion Wayne & Russ Millions - Body Tom Grennan - Little Bit Of Love Best new artist Little Simz Central Cee Griff Joy Crookes Self Esteem Best international artist Billie Eilish Doja Cat Lil Nas X Olivia Rodrigo Taylor Swift Best international group Silk Sonic Abba BTS Maneskin War On Drugs Best international song Olivia Rodrigo - Good 4U ATB / Topic / A7S - Your Love (9PM) Billie Eilish - Happier Than Ever Ckay - Love Nwantiti (Ah Ah Ah) Doja Cat ft SZA - Kiss Me More Drake ft Lil Baby - Girls Want Girls Galantis, David Guetta & Little Mix - Heartbreak Anthem Jonasu - Black Magic Kid Laroi & Justin Bieber - Stay Lil Nas X - Montero (Call Me By Your Name) Lil TJ & 6lack - Calling My Phone Maneskin - I Wanna Be Your Slave Polo G - Rapstar Tiesto - The Business The Weeknd - Save Your Tears Brits Rising Star Holly Humberstone Bree Runway Lola Young Best dance Becky Hill Calvin Harris Fred Again Joel Corry Raye Best rock/alternative Sam Fender Coldplay Glass Animals Tom Grennan Wolf Alice Best pop/R&B Dua Lipa Adele Ed Sheeran Griff Joy Crookes Best hip-hop/grime/rap Dave AJ Tracey Central Cee Ghetts Little Simz Producer of the year Inflo Songwriter of the year Ed Sheeran" https://www.bbc.com/pidgin/tori-60314980 +sports Barcelona v Real Madrid: La Liga wan go court ontop di new El Clasico date "La Liga dey reason am to carri di Spanish Football Federation (RFEF) go court ontop say dem postponed El Clasico between Barcelona and Real Madrid to 18 December. Di match suppose happun on Saturday 26 October for Barcelona but RFEF postpone am after La Liga say dem dey fear say gbege fit happun. Protests don dey happun for Barcelona since last week afta nine Catalan separatist leaders get jail sentence earlier dis month. La Liga want make di new date be 4 December. Wen RFEF competitions committee ask both clubs which new date dem want, dem say na Wednesday, 18 December. Di first round of Copa del Rey competition go begin on dat same date too. ""La Liga no gree wit di competition committee decision to select 18 December - afta dem reach agreement wit Barcelona and Real Madrid, even though Liga say dem no want am - as di date wey di postponed Clasico go now happun,"" La Liga tok for statement. ""We dey study di document... in order to torchlight how we take carri di mata go court."" La Liga bin wan move di match go Madrid before but di two clubs reject di plan. Catalonia - wey Barcelona dey based - na semi-autonomous region for north-east Spain and inside referendum wey dem do on 1 October 2017, around 90% of Catalan votes support say make dem dey independent. Spain Constitutional Court don declare di referendum illegal. Spain Supreme Court convict nine separatist leaders ontop dia role inside di referendum and nack dem jail sentences of between nine and 13 years." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50115014 +politics David Lyon don win APC govnorship primaries for Bayelsa David Lyon don win di govnorship primaries for di All Progressives Congress (APC) for Bayelsa state afta primaries for di eight local goment for di state. Lyon win wit total of 42,138 votes followed by one of di female aspirants, former police commissioner Diseye Nsirim Poweigha wey get 1,533 votes. Odas wey follow contest na Preye Aganaba, Prince Ebitimi Amgbare, Ongoebi Maureen Etebu and di main opponent Sen. Heineken Lokpobiri wey get 571 votes. Dis one mean say David Lyon go face di PDP candidate, Douye Diri and odas for di election wey go hold for 16 November. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49583034 +entertainment Pete Davidson: Kim Kardashian and Pete Davidson dey date? Reality star, Kim Kardashian don land news again on top weda she dey date comedian, Pete Davidson. Dem bin first collabo for public wen di fashionista bin host di American show Saturday Night Live, wia di comedian dey work for October dis year. And now, many media organisations don claim say di couple now fit dey officially date. According to E! News, source close to di 41 year old mother of four say dem dey officially date now, even though e dey casual and dem wan see how e go go. Page Six don also declare say, dem dey officially togeda. Tori be say, two of dem bin know diaself before but di pair reconnect for di filming of di show Saturday Night Live wey dem bin get skit wey dem kiss each oda. Before dat one go calm down, picture catch dem for Halloween ride for October wey dem bin dey hold each oda hand as dem bin dey shout. Tori come comot some days afta say dem go dinner togeda for one restaurant for Staten Island. But di biggest clue for dia growing relationship na wen Pete Davidson spend im birthday for Kim mama house dey wear matching pyjamas with Kanye West ex. Right now, Kim Kardashian dey go through divorce with di papa of her four pikin, Kanye West. She don previously dey involved with Ray J, Nick Cannon, Kris Humpries among odas. For im own right, Pete Davidson bin engage to singer Ariana Grande for 2018 but dat one no last. E don also date Hollywood star, Kate Beckinsale and Bridgerton star Pheobe Dynevor. https://www.bbc.com/pidgin/world-59344364 +politics Inec declare Douye Diri winner of Bayelsa Governorship election: Takeaways from Supreme court judgement wey cancel APC victory Di independent National Electoral Commission of Nigeria Inec don declare di opposition Peoples Democratic Party candidate of di govnorship election of Bayelsa state as di winner of di election. On Thursday, Supreme Court for Abuja cancel Bayelsa State governor-elect David Lyon as winner of di 2019 election for di state. Di five-man panel of Nigeria highest court declare PDP candidate Douye Diri as winner of di state governorship election. See wetin you need to know about di judgement. Di two govnorship candidates of di All Progressive Congress party (APC), di govnor and deputy govnor get joint ticket. So dia for, di decision wey affect one pesin, affect di oda. Di judgement indict di Deputy-Govnor elect Biobarakum Degi-Eremienyo say im present fake certificate. So as a result of dia joint ticket, di Supreme Court disqualify di two candidates and dem no be candidates again for di govnorship election. Since oga David Lyon and im deputy oga Degi-Eremienyo no be candidate again, Supreme Court don order Inec make dem declare di candidate wit di highest number of lawful votes and di right constitutional spread. Dem also order Inec to also collect Certificate of Return from oga Lyon and im deputy hand, den give fresh Certificate of Return to di pesin with di highest number of lawful votes. INEC don accept di judgement of di supreme court say dem go give di PDP Douye Diri im certificate of return. Di court also rule say all di parties wey follow do dis court case go bear dia cost for all di moni wey dem spend. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51502442 +politics Ghana Presidential Elections results and Parliamentary election results Ghana update explainer "Ghana election 2020 dey hold on Monday 7 December, wen Ghanaians go form long queues across de country to elect a new President who take over governance of de country. Electoral Commission of Ghana [EC] put out 12 presidential candidates who voters go choose from. Out of de twelve, de two favourites who form government since de start of de Fourth Republic wey start in 1992 be de candidates of di ruling New Patriotic Party (NPP), National Democratic Congress (NDC) who be de main opposition party. Apart from de presidential candidates, voters go elect 275 parliamentary candidates who go occupy de law-making institution alias Ghana paliament. So what type of voting system [How election dey conducted in Ghana] dey use in determining who go win elections on December 7? Since de inception of de Fourth Republic, Ghana dey practice voting system - First Past the Post alias Simple Majority. Dis system be one of de most straightforward ways to determine who go win elections in most political systems. Under de ""First Past the Post"" or simple majority system, de candidate with de highest number of votes be winner of de election. In other words, de candidate wey go get majority votes be winner of de elections. Per de 1992 Constitution of Ghana, candidate who go gather 50 percent plus of valid votes cast be winner of de elections. Despite de 50 percent votes which dey determine who go win elections, Ghana electoral system make provision in case no candidate secure more than 50 percent of total votes cast. Per de 1992 Constitution of Ghana, if no candidate get over 50 percent votes, de electoral commission go hold second election between de two leading candidates within 21 days. So voters go once again queue to vote for de top two parties to determine who go win de election. On election day, Ghanaians go cast dema ballots from polling stations wey Electoral Commission create across de country. When voter visit de polling station, Gha [EC] Electoral Commission officials go check Voter ID to be sure say de person be registered voter. Once you be registered voter, dem go give you one ballot paper which you go take vote for presidential candidate of choice, drop am in de ballot box. Then officials go give de voter second ballot paper to vote for de preferred member of parliament. On December 7, 2020 de candidate who go emerge winner with over 50 percent of valid votes cast become President of Ghana on January 7, 2021 where per de constitution dem go swear am in. After dem swear de Prez in, he go appoint en Speaker of Parliament who now go convene new parliament of lawmakers for de country. Presidential elections hold for de first time in Ghana on 27 April 1960. De elections hold alongside a referendum on creating an executive presidency. De winner of de election go become de country' first President if de new republican constitution was passed (which be happun). Ghana wey be formerly known as de Gold Coast. On 6 March 1957 Kwame Nkrumah declared de country's independence. On 1 July [1960], Ghana become a commonwealth republic with Kwame Nkrumah as de first President of de country. But 1966 de country first president and pan-African hero, Kwame Nkrumah, dema remove am in a coup, leading toyears of mostly-military rule. In April 1992 a constitution allowing for a multi-party system be approved in a referendum, leading to a period of democracy. Ghana be many times seen as a model for political and economic reform in Africa, according to UNDP." https://www.bbc.com/pidgin/world-55242339 +entertainment Tiwa Savage video: Five things to know about di Afrobeat singer allege sex video "Ogbonge Afrobeats musician Tiwa Savage sex tape mata na still di biggest gist for Nigeria afta one video bin leak for social media on Monday evening 18, October 2021. Although BBC Pidgin never confam di originality if na Tiwa Savage dey inside di video or not, many pipo don chook mouth inside di mata. Tori be say na for one interview wey Tiwa do wit radio host Angie Martinez of Power 105.1 for New York early dis month she first reveal di mata of di sex tape. For dat interview she say somebody dey try blackmail her sake of sex tape. Savage, wey be 41 years, na one of di biggest Afrobeats stars for di world and she dey signed to Universal Music Group. So how dis sex tape land for internet? According to Tiwa she say her lover na im post di video for Snapchat by accident and im bin delete am afta him realise im make mistake but one pesin bin don already download am. She add say she bin cry wen she first see di video and fear for di kain reaction she go get. Tiwa say di blackmailers bin dey ask her for money but she no go pay dem shishi. ""I decide say I no pay di pesin because if I do, two months from now, three months down the line or even two years later, dem go come back again,"" she tok. ""Who knows, if I send di money, di pesin go probably release am. I no go let anybody to blackmail me onto say I do something natural."" She add put Dis one hard to answer, but distance from dia love interests fit be di major factor why dem dey do dis kain tin. Actors dey spend months away from dia spouses and lovers sake of dia work. And Musicians too dey tour di world for months. So Sexting fit be option for dem to spice up dia relationship. Tiwa Savage don react to di allege sex video. For inside post wey she put for social media, Tiwa bin tell di pipo wey dey behind di sex video say dem hate her sake of say she take di matter wey dem wan take destroy am joke for stage. ""You hate how I dey able to control di narrative and get ahead of one story before e consume me and how i dey able to joke on stage about something you bin think say suppose destroy me and make me shame."" ""You must knock my head wen you see me otherwise…"" she post. Na mixed reaction from celebs and fans wey chook mouth inside di mata. Some of her colleague try to rally around her as dem dey post her picture wit di #queen while odas blast her for wetin she do." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58977792 +sports Portugal vs Nigeria- All you need know Nigeria men national football team go play Portugal for international friendly match dis week. Dis match dey come few days before di start of di Fifa World Cup in Qatar. Super Eagles no dey go World Cup but Portugal dey go. Di European team dey di same group wit Ghana, Uruguay and South Korea for di tournament. Di match na Portugal last build up game ahead of di big football tournament for Middle East. Dis game dey come afta di ogbonge interview wey Cristiano Ronaldo do wit Piers Morgan wia im accuse Manchester United of betrayal and oda tins. Dis Na wetin you need know about di international friendly game. Di international friendly game between Portugal and Nigeria go take place on Thursday November 17. Di International friendly match go begin by 7:45pm Nigeria time dat na 6:45pm for Portugal. Nigeria invite 23 players for dis friendly match against Portugal But head coach Jose Peseiro don replace Victor Osimhen wit Cyriel Dessers and Chidozie Awaziem come in for Olisah Ndah. Im replace dem sake of Injury. Goalkeepers: Maduka Okoye, Francis Uzoho, Adebayo Adeleye Defenders: William Ekong, Olisa Ndah, Calvin Bassey, Kevin Akpoguma, Chidiebube Duru, Tyronne Ebuehi, Bruno Onyemaechi, Bright Osayi Samuel Midfielders: Joseph Ayodele-Aribo, Alex Iwobi, Wilfred Ndidi, Frank Onyeka, Oghenekaro Etebo Forwards: Moses Simon, Samuel Chukwueze, Ademola Lookman, Terem Moffi, Paul Onuachu and Emmanuel Dennis Portugal team news Goalkeepers: Diogo Costa, Jose Sa, Rui Patricio Defenders: Diogo Dalot, Joao Cancelo, Danilo Pereira, Pepe, Ruben Dias, Antonio Silva, Nuno Mendes, Raphael Guerreiro Goalkeepers: Diogo Costa, Jose Sa, Rui Patricio Defenders: Diogo Dalot, Joao Cancelo, Danilo Pereira, Pepe, Ruben Dias, Antonio Silva, Nuno Mendes, Raphael Guerreiro Midfielders: Joao Palhinha, Ruben Neves, Bernardo Silva, Bruno Fernandes, Joao Mario, Matheus Nunes, Otavio Monteiro, Vitinha, William Carvalho Forwards: Andre Silva, Cristiano Ronaldo, Goncalo Ramos, Joao Felix, Rafael Leao, Ricardo Horta SuperSports go show di Portugal vs Nigeria match live for Nigeria. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyxjll57j9po +politics Nigeria vs Ghana: Lai Mohammed, Minister of Information warn 'enough is enough!' for Ghana – Nigeria relations E be like say di diplomatic relations between Nigerian and Ghana don dey get k-leg sake of how Ghanaian goment di close retail shops wey belong to Nigerians. Nigeria goment say dem don record and document all di bad-bad tins wey Ghana authorities don do for Nigerians living in. Dem mention some of dem wey include: Federal goment tok say even though over 1 million Ghanaians dey live for Nigeria, demm no dey treat dem di way Ghana dey treat Nigerians. Oga Lai say di reason Ghana authorities give for di property wey dey No. 10, Barnes Road in Accra wey dem seize sake of say dem no renew di lease afta e expire no make sense as plenty Ghana goment property wey dia rent dey Nigeria don expire and dem no use because of that seize dem. Nigeria say Ghana dey take dia relationship for granted and dem beg dia citizens wey dey Ghana make dem remain law abiding. Meanwhile di diplomatic relations between Nigerian and Ghana don dey get k-leg sake of how Ghanaian goment dey close retail shops wey belong to Nigerians. Di latest tori be say Ghanaian authority summon Nigeria Chargé d'Affaires to Ghana, Esther Adebola Arewa, make e answa query on top how Nigeria goment criticise dia policy to close retail shops wey belong to Nigerians. Di Nigerian foreign minister, Geoffery Onyeama bin say di Ghana policy dey against Ecowas protocol of free trade and dat dem go drag Ghana go Ecowas court to judge di mata. But Ghana Foreign affairs minister Shirley Ayorkor Botchwey on top tweet say dia policy no target any particular kontri and dat sometimes, kontris gatz make tough decision to enforce dia laws. She yarn give say even Nigeria last year close im borders to fight smuggling despite say dey decision affect oda members of ecowas kontri. She further explain give say di believe say di crackdown on top shop dey politically motivated, no be true and dat e dey unfortunate for Nigeria foreign minister to think say dem di do am for political gain. She say as e be now, Ghanaian law forbid any foreigner to engage for retail business especially inside di local market as leaders of for those market di put pressure on di goment to enforce dem. So far, Ghana don close more than 200 shops wey belong to Nigerians. Recently, di Nigerian goment also summon Ghana ambassador to Nigeria wia she promise say di goment don suspend di policy but wit dis latest report, e be like say di two kontri di head to put leg inside one trouser. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53908892 +sports Super Eagles appoint Joseph Yobo as assistant coach Nigeria Football Federation don appoint former Super Eagles captain Joseph Yobo as assistant coach of di team. Yobo wey play for six Nations Cup for Nigeria as defender go replace Imama Amapakabo for Nigeria technical crew. Di defender play for three World Cups for Nigeria and bin be di captain of di Super Eagles wen dem win di 2013 Africa Cup of Nations. NFF announce dis appointment for inside statement on Wednesday . Yobo wey play 100 matches for Super Eagles also play for Everton, Fenerbahce, Marseille, Standard Liege and Norwich City. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51479424 +sports Manchester United go fight any attempt to ban Christiano Ronaldo "Manchester United say dem go  fight any attempt to ban Cristiano Ronaldo sake of di mobile phone incident for Everton last April. United manager Erik ten Hag tok today say Ronaldo no go accept di FA 'improper and violent conduct' charge. Ronaldo bin kolet warning from police afta e knack phone comot from one fan hand. Di incident happun afta dia 1-0 loss to Everton for Goodison Park. Dem give am until Monday evening to respond to di FA charge, wey dem only fit chook eye put sake of say di involvement of Merseyside Police for di case don end for August. Manchester United neva tok wetin Ronaldo answer be. ""We don tok about am and e no go accept am "" Ten Hag, tok ahead of dia Europa League group game against Cypriot side Omonia Nicosia on Thursday. Di club don make oga Ten Hag comment clearer, dem say Ronaldo no go accept any harsh punishment, wey United feel say dey unfair, instead of argument say di incident no happun. Pipo binndey fire Cristiano Ronaldo afta one video showface wey look like say im knack one Everton fan phone for ground. Bodi bin no sweet di Manchester United player and im teammates afta dem loss lose to Everton dat Saturday inside Goodison Park. Later dat day Ronaldo waka enta social media wit millions of followers to tok sorry. Ronaldo say, ""e no dey easy to deal with emotions for difficult moments like di one we dey face."" Di football star add say, ""I go like tok sorry for my outburst and if e possible invite dis supporter make e come watch match for Old Trafford as a sign of fair play and sportsmanship"". Di loss against Everton bin spoil Manchester United chances to qualify for Champions league." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0d919pw71jo +health Coronavirus variant: Matt Hancock, UK Health Secretary say dem identify new form of Covid-19 "UK Health Secretary Matt Hancock don tell MPs say dem don identify new variant of coronavirus wey fit dey associated with faster spread. Health Secretary Matt Hancock say at least 60 different local authorities inside England don record Covid infections wey dis new form of covid cause. He say di World Health Organization don dey notified and Porton Down dey do detailed studies about di mata. Mr Hancock say ""nothing dey to suggest"" say e cause worse disease or say vaccines no go work again. E tell MPs for di House of Commons say over di last week, sharp rise dey for di virus across London, Kent, parts of Essex and Hertfordshire. ""We no know di extent to which dis one be because of di new variant but no matter di cause we need to take swift and decisive action wey unfortunately dey absolutely essential to control dis deadly disease while dem roll out di vaccine."" Prof Alan McNally, expert for di University of Birmingham, say UK testing labs picked up on dis new variant in di last few weeks. ""Huge efforts dey ongoing to chook eye for di variant and understand di emergence. E dey important to keep calm and chook eye for di new form with rational mind as dis na normal virus evolution and we expect new variants to come and go and emerge over time.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-55308946 +politics Ernest Shonekan dead: Tribute pour in as former Nigeria president Ernest Shonekan die "Nigerians don take to social media to mourn di death of former Nigeria leader Chief Ernest Shonekan. Shonekan die for Lagos, south-west of Nigeria at di age of 85. Former Nigerian senator, Ben Murray Bruce tweet say Oga Shonekan dey very special to im family. ""I go visit am, and im go tell me di challenges wey im dey face wey make am close Kingsway stores. Great man. We go miss am dearly."" oga Bruce tok. Im be di 9th head of state for Nigeria. Oga Shonekan be interim head of di Nigerian Government between August 26 and November 17 1993 Na one coup wey wey late General Sani Abacha carry out na im comot am from office. Before im death, Shonekan na lawyer, industrialist, and former Chief Executive of diUnited African Company of Nigeria Plc (UAC) Dem appoint am as Interim President of Nigeria by General Ibrahim Babangida for 1993. For January 2, 1993, Shonekan assume office as head of di transitional council and head of government under General Babangida. Dat time, dem design di transitional council to be di final phase wey go lead to handover for elected democratic leader of di Third Nigerian Republic. Babangida later resign from office for August 1993, afta dem cancel di June 12 presidential election. Im bin don sign decree to establish di Interim National Government wey Shonekan lead and dem swear am in as Head of State. Three months into im administration, dem overthrow Shonekan for one palace coup by Abacha for November dat year. Oga Shonekan later found one Nigerian Economic Summit Group wey be advocacy group and think-tank for private sector-led development of di Nigerian economy. Since then, Shonekan bin dey show face mainly as elder statesman." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59950564 +entertainment Big Brother Naija 2021: When season 6 go start, how to watch & oda tins wey go change for di new season "Africa Biggest Reality TV show, Big Brother Naija season 6 go start on July 26, 2021. According to di organizers wey give di informate, everything don set for di programme to start. For di sixth season, Big Brother Naija go feature special double launch show on Saturday July 24 and on Sunday July 25th And for di first time for history, BBNaija fans for di United Kingdom go fit watch di live show 24/7 through African online streaming service, Showmax. Di Chief Executive Officer of MultiChoice Nigeria, John Ugbe say for dis season 6, dem dey go all di way to give dia customers di kain show dem neva see before. ""For dis sixth season, we dey pull all di stops to give our customers a show like never seen before from Nigeria wit end to end production best practices under global health and safety standards."" John Ugbe tok. Di grand prize for di season na N90million naira worth of prizes, wey be di biggest money any winner don get from di reality show since dem start am. Na also di highest money for ant TV reality show for di continent. No SMS voting dis season. Voting go only be on web and MyDStv and on top MYGOtv apps. Viewers for UK go fit watch di show live on Showmax. For dis year, di show dey start wit Double Launch. Di reality show wey go last for 10 weeks go follow di lives of strangers as dem interact and compete wit each oda to win di grand prize of N90million worth of prizes, wey be di biggest reward for any reality show for di continent. Big Brother Naija season 6 go run 24/7 on DSTV Premium, Compact Plus, Compact, Confam and Yanga packages on channel 198 and on top GOtv Max and Jolli packages on channel 29. According to di organizers, 49 African kontris watch di reality show last season." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57891434 +sports Nicolas Pepe: Arsenal break record sign Ivory Coast player for £72m "Arsenal don sign Ivory Coast player Nicolas Pepe for a club record fee of £72m. Di 24 year old sign five year contract for Emirates Stadium, afta im do im medical on Tuesday. Pepe play 74 times for Ligue 1 team Lille and score 35 goals, im join dem from Angers for 2017. ""Nicolas na talented winger wey many top teams for Europe bin dey eye,"" na wetin Gunners manager Unai Emery tok. ""To sign top- class winner na one of our main targets for di transfer window and belle sweet me say im join us. ""Im go add power, speed and skill, with aim to bring more goals come our team.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-49196856 +sports Lionel Messi: Pedri pass to Barcelona FC player Messi break Pele scoring record "Lionel Messi don break one of Pele record after im score goal number 644 for Barcelona during im team victory over Real Valladolid on Tuesday night. Argentina forward Messi, score Barca third goal when im collect backheel pass from Pedri, take one touch come waya shot pass goalkeeper Jordi Masip. Pele, di football legend, bin hold di record of player wey score di most goals for one club, wit im 643 goals in 19 seasons for Brazilian club Santos between 1956 and 1974. Messi, score im first Barca goal for 2005 and since then im don win 10 La Liga titles and four Champions Leagues with di Spanish club. If difference fit dey from di records of di two players, e go be say Pele - wey im birth name na Edson Arantes do Nascimento - score im 643 goals for im home country club, while Messi do am for foreign club. After Messi been match Pele record few days earlier, di Brazilian congratulate am. ""Congratulations on your historic record, Lionel...I admire you well-well,"" Pele bin write ontop im Instagram page. For years many don compare di two players, as some say Messi don pass Pele as di best player to play di game of football, tok wey Pele ogbonge followers don reject." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55408142 +entertainment Yul Edochie new wife Judy Austin: 'Yul make mistake, we feel for Mary' - How Edochie family react to 'second wife' mata "Di family of Yul Edochie don chook mouth for di reaction wey follow di announcement of di Nollywood actor say e don marry anoda wife. Uche Edochie di senior broda of di actor say wetin happun neva reach to condemn im broda. For social media post on top im social media handle di senior Edochie say true true im broda no be Muslim, di law for Nigeria allow am to get two wives. E say: ""Traditional rulers and traditionalists of sorts do di same tin too and di Nigerian constitution recognize polygamy as a legal marital union."" Uche also say im family no dey happy wit Yul sake of di ""mistake"" wey e make and dem no dey ""in support"" of wetin di actor do. Mary na Yul Edochie wife and dem get four children togeda - afta 17 years of marriage. Uche Edochie say di essence of di response na sake of how Nigerians dey vex for wetin Yul. ""Wen Muslim marry two or more wives and im pipo throw party. Dat one dey totally normal. Wen Christian do di same tin and e go become di worst human being alive."" E say Mary na better woman wey no derserve wetin happun to her. ""So my younger brother Yul Edochie just marry a second wife just like dat and Nigerians dey surprised. I understand. Di mata shock all of us. ""Im first wife Mary, a wonderful woman and my sister in law no go into relationship wit my broda agreeing to be part of a polygamous marriage. ""I feel for Mary. E no dey fair on her. My family no dey in support of wetin happun. We no dey do dis kain tin and we dey try our best to console Mary. ""Wetin again we fit do? We tell Yul make e no do am. ""Yul na adult wey feel say to marry second woman na di best way to accept im mistake and make tins right ""Women throw themselves at famous people so bad that it is suffocating,"" e tok. Uche Edochie say most pipo no do worst if dem dey in di same position wit Yul. E say though im broda don make mistake e no make sense to judge am - ""If average pesin get di kain fame wey Yul get dem go get they will get five or more women pregnant. ""So don't be quick to judge if you neva live dat life. Most people will do worse."" Ogbonge Nollywood actor Yul Edochie on Wednesday reveal say im welcome baby boy wit im second wife, Judy Austin Muoghalu. Di actor make di revelation on im Instagram page and share fotos of im son and im second wife as im disclose say e love di boy di way im love im oda children. For di post Yul tok say di boy name na Star Dike Munachimso Yul-Edochie. Judy Austin Muoghalu na di reported tear rubber wife of di Nollywood actor. Judy wey be Nollywood actress and movie Producer and Brand Influencer come from Anambra State, south-east Nigeria. According to her Instagram handle she be di CEO of Judyaustin Boutique She and di Nigerian actor don act plenti feems togeda like Native Girl, Fear The Street Girl I love, Where I belong, Trouble Comes to Town, and Secret of The Riches. Nigerians go tanda for her instagram handle wit many reactions afta Yul Edochie brak di tori. While some followers dey congratulate her, odas no happy wit di tori. According to di Nigeria famous actor and movie Producer, Yul Edochie, e marry im first wife May Yul-Edochie for 2004. For one of im Instagram post last year di ogbonge Nigeria actor bin dey celebrate im wife. For di post Yul tok as she take marry am wen im bin no get anything and how she dey give am happiness for im life.Di couple mark dia 17 years wedding anniversary last year. According to her Instagram page of over 130k followers, May na entrepreneur. As di tori comot on Wednesday, pipo for social media bin dey try find answer to why im ""marry second wife"", abi na becos of pikin or male child? But di fact be say,only Yul Edochie fit tok di reason why e marry Judy. May Yul-Edochie born four pikin dem wit her husband. The children na three boys and one girl. The only girl among dey bin get excellent result for her exams and Yul come social media come celebrate her. She dey higher institution now. Yul dey always post pictures of im family for social media. Yul Edochie na di son of ogbonge actor Pete Edochie. Yul wey join acting many years ago don star for different popular movies and some of dem include Idemili, Devil in Red, and Show Down. Apart from say im be actor, Yul na also politician and im don tok say e go like be Nigerian president for 2023. Di actor wey be forty-years marry im first wife Judy wen im dey 22 years" https://www.bbc.com/pidgin/tori-61269129 +sports Napoli striker Victor Osimhen test positive for coronavirus Italy club Napoli don announce say dia Nigerian striker, Victor Osimhen don test positive for Covid-19 Di club say di Osimhen return positive result of di test on e return from Belgium wia im bin go for treatment on e shoulder injury. Di 21-year-old don dey sidelined since last November after e dislocate im shoulder wen e bin represent Nigeria for di Africa Cup of Nations qualifier against Sierra Leone. According to post wey di club make on dia twitter handle dem say di player no dey show any symptom. Di club also add say Osimhen never come into contact wit di rest of di Napoli squad. Osimhen join Napoli from French side Lille during di 2020 summer transfer window. Im don score two goals in six league appearances, but nevery play since November 8 because of di shoulder injury. https://www.bbc.com/pidgin/sport-55511176 +health Coronavirus symptoms: Ghana don record first cases of Covid-19 outbreak, patients enter Ghana one week before symptoms start dey show "Ghanaian authorities say dem don start di process of tracing everyone wey bin contact di first two patients wey test positive for Covid-19 disease. Health Minister Kwasi Agyemang-Manu wey confam di first two cases on Thursday night announce say both individuals enter Ghana from Norway den Turkey. ""We start de process of contact tracing. We want assure Ghanaians say Govment den health partners go make sure de situation be contained"" Mr Manu add. BBC Pidgin find out say di two coronavirus patients enter Ghana for like one week before symptoms start dey show. Both patients according authorities dey Ghana for one one week before de virus finally start dey manifest. De Ghanaian dey work outside de country but en flight come from Turkey into Ghana. According Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah reveal ""yeste dem complain of symptoms so dem place place inside isolation."" ""Noguchi test dema blood samples wey somewhere around 7.00pm dat be when filla drop say dem test positive for de virus inside meeting"" he add. Doctors start treatment on de two soon as de results come. Tori be say dem don keep di two patients wey get di coronavirus for isolation alias separate ward, althogh nobody know where di ward dey. Health Ministry for Ghana set up 100-bed capacity facility inside one remote area to quarantine suspected cases. De two cases test positive after laboratory tests from de Noguchi Memorial Institute of Medical Research on 12 March, 2020. Ghana Ministry of Health say dem dey for stable condition. On Wednesday Ghana step up preparations and response plan to deal with coronavirus plus $100 million dollar financial commitment. Prez Akufo-Addo announce Wednesday night inside national address say he direct en finance minister make he release dis fund. Dis monies go ""expand infrastructure, buy materials and equipment, and public education"" Akufo-Addo explain. During de address Ghanaian leader also urge nationals make dem shun dey foreign travels for now. ""All of us for shun foreign travels, except de most critical ones until de virus matter finish"" President Akufo-Addo talk." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51867414 +business US and Taiwan wan do trade tok-tok as China dey beef di Island nation "America don announce say dem go start fromal trade negotiations with Taiwan. Dis dey come three weeks afta US House Speaker Nancy Pelosi visit wey cause serious gbas-gbos. Di Office of di US Trade Representatives say di first round of tok-tok suppose start for ""early fall"". Dia tok-tok go include trade facilitation, digital trade and anti-corruption standards. Di relationship between di US and China don dey tough afta Ms Pelosi go Taiwan. Di US-Taiwan Initiative for 21st Century Trade bin first dey announced for June. Both sides dey now tok say, dem don ""reach consensus for di negotiating mandate"". Trade between US and Taiwan for 2020 bin dey worth almost $106bn (£88bn). Di announcement dey come wen China don launch dia biggest military exercises ever around Taiwan afta Ms Pelosi visit for early August. Under di ""One China policy"", American get formal relationship with China and not di island of Taiwan. But dem also get unofficial relations with Taiwan including continuous arms sales go di island so dem go fit defend dia self. Beijing see di self governing island as part of dem, wayward territory wey dem go unite with mainland. But Taiwan na self ruled island wey ee demselves as separate from di mainland. Sperately on Thursday, correct US diplomat for East Asia, Daniel Kritenbrink say Beijing ""growing gra-gra... dey threaten di peace and coole mind of di Taiwan Strait"". E add say, ""we go continue to take calm but correct steps to uphold peac and stability as Beijing dey do dia own to go against am and support Taiwan as our long standing policy allow am""." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cy7lr924r82o +entertainment Omah Lay: Uganda Police arrest Nigerian singer say e disobey Covid-19 guidelines "Uganda Police don arrest popular Nigerian Singer, Omah Lay and two odas for disobeying Covid-19 guidelines. Uganda police force confam dis report for one statement wey dia Public Relations Officer, SP Patrick Onyango bring come out today; ""Three pipo na we don arrest in connection to unauthorised concert wey dem hold last night in Ddungu Resort inside Munyonyo, Kampala City."" ""Those wey we arrest na; Ivan Ddungu, di manager of di place where di concert dey hold, Omah Lay di musician and Prim Kasana, di events Manager, wey carry Omah Lay come di kontri to sing."" Kampala Metropolitan deputy Police tok-tok pesin, ASP Luke Owoyesigire also confam di arrest for twitter as rumours dey go round say may Omah Lay don already fly comot from di kontri since pipo no see visible evidence or images of im arrest. Di Police say dem dey also looking for di area Officer in Charge of Police Station on top say im fail to detect di criminal acts wey happun for im area of jurisdiction. Omah Lay bin travel go Uganda to perform for di Big Brunch event wey take place for Ddungu Resort inside Munyonyo, Kampala on Saturday 12 December. Police say di organizers of di show disguise say dem dey do lunch and dinner event, but later on for night dem start to dey invite artistes; ""Allegation say di organizers of di show disguise am as lunch and dinner event, but later on at night dem start to invite artistes to perform. ""Di suspects dey detained for Katwe Police Station and dem go get charged with doing acts wey dey likely to cause di spread of infectious disease, wey be corona virus."" ""On di beginning of di COVID19 pandemic, di president direct say make dem stop music concerts and di directives still stands. ""We condemn di act of some selfish individuals, wey dey bent on violating di directives on COVID-19 to make money and risks di lives of many Ugandans."" Ugandan police force beg members of di public to obey di Ministry of Health guidelines on coronavirus. Meanwhile, #freeOmahLay don dey trend for social media as fans of di artist dey react to di news of im arrest." https://www.bbc.com/pidgin/world-55296366 +sports Carlo Ancelotti: Everton don appoint Champions league winning coach as manager "Everton don appoint Carlo Ancelotti as dai manager for four-and-a-half-year deal. Ancelotti wey Napoli bin sack early dis month, go take ova from Marco Silva, wey Everton sack for 6 December. Ancelotti, wey be Italian na three-time Champions League-winning coach. E return to English football eight and a half years afta Chelsea sack am. Everton announce Ancelotti arrival on Saturday before di home Premier League game against Arsenal, wey appoint former Gunners and Toffees midfielder Mikel Arteta as dia head coach on Friday. Ancelotti wey be 60 years old go officially take ova Sunday and im first match in charge go be di home game against Burnley on 26 December. Oga Ancelotti wey be former AC Milan, Real Madrid, Bayern Munich and Paris St-Germain boss tok say Everton ""na great club with rich history and a very passionate fanbase."" ""E get clear vision from di owner and di board to deliver trophies. Dat na something wey I like me as a manager. ""I dey happy say I go dey able to work with everybody for di club to help make dat vision to dey real."" Ancelotti don win 15 major trophies during im career and im na one of only three managers to win three European Cups/Champions Leagues - along with Liverpool legend Bob Paisley and Real Madrid boss Zinedine Zidane. E guide Chelsea go di Premier League and FA Cup double during im first season in charge for 2009-10 but dem sack am afta e fail to win trophy for di following campaign. Everton director of football, Marcel Brands tok say Ancelotti na ""one of di finest managers for di world football"" and na ""proven winner"". ""Carlo na di perfect appointment for us,"" e add. ""E know how to build trophy-winning side and we share di excitement of our fans for di prospect of him leading our team for di years ahead."" Everton start di weekend 16th for di Premier League table - three points above di relegation zone." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50878539 +entertainment Brenda Song and Macaulay Culkin: How di child stars relationship produce dia pikin "Home Alone Star Macaulay Culkin, 40, and Suite Life star Brenda Song, 33, don born dia first pikin four years afta dem bin meet. Na on Monday di couple release dis one for inside statement say dem born dia son for di 5th of April 2021. Dem name di boy, Dakota Song Culkin afta Macaulay sister wey die for 2008 from road accident. Di two former child stars bin manage to keep di whole pregnancy as secret and e bin shock di world wen di tori land outside. Till di time of dis tori both parties still neva post anytin for dia social media, but dia reps bin comot with statement of di birth. Oga Culkin bin tok for one Joe Rogan interview say Song na good woman so, ""I go probably put some pikin dem for her belle. We dey practice."" Culkin and Song don keep dia relationship lowkey but di actor, tok for Esquire say dem bin meet for set of di 2019 movie Changeland for 2017. And bin confam say dem bin dey date afta di two of dem do vacation with Michael Jackson pikin, Paris for December of 2017. Back in 2019, Mack as dem dey call am reveal for interview say dem bin buy house togeda and dey practice to get belle. Before dia relationship, Macauley bin date actress Mila Kunis for almost nine years till 2012 and marry don marry before. While Brenda bin dey engaged to Miley Cyrus older brother Trace Cyrus but dem too break up for 2012. But dis go be di two celbs dem first pikin." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56715624 +politics Orji Uzor Kalu: Senator Kalu tok why e drop out of APC presidential race, Tinubu and odas remain "Senator Orji Uzor kalu don drop out of di presidential race for Nigeria ruling All Progressive Congress party. Kalu wey be Chief Whip of 9th Senate announce im withdrawal from di race for official statement wey e release on Tuesday. ""In di absence of zoning, I go return back to Senate and comot hand from di presidential contest."" na wetin Senator Kalu tok. ""Di reality be say di North get more advantage to win elections for dis democratic setting."" e add put. Dis announcement dey come as di party officially begin di sale of dia 100 million naira presidential form. According to informate from di party di Special Convention for Presidential Primaries go happun for 30th of May to 1st June, 2022. Six candidates still remain for di race to fight for di party ticket ahead of di primaries wey go happun next month. ""Forms for female aspirants and pipo wey dey live wit disability na free."" APC add. ""Youth wey dey age 25 - 40 years get 50% discount to buy di nomination forms,"" Argungu tok. President Muhammadu Buhari go end in four year term for office for 2023. Next year Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023 according to di election office INEC." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61234493 +sports China ban dia national football players from getting tattoos "Footballers wey dey play for China national team don dey banned from getting tattoos - and advise those wey get tattoo to comot am - under one new directive. Di kontri sports administration body say recruiting new players wit tattoos for national level and to youth squads dey ""strictly prohibited"". Di administration say di move go help set ""good example for society"". Dem bin warn some national stars wey include defender Zhang Linpeng to cover their tattoos. Na since 2018 China don dey step up regulation to stop make dem dey show tattoos on screens. Some professional footballers dey cover their arms wit long sleeves to hide their body art. For inside statement, di kontri General Administration of Sport (GAS) say national players wit tattoos bin dey ""advised to remove dem"". ""For special circumstances, di tattoos must dey covered during training and competition, wit di consent of di rest of di team,"" e tok. For Chinese culture, stigma dey attached to tattoos - before-before dem dey use am brand criminals and di tattoo still get links to organised crime groups for east Asia. Tattoos among ethnic groups dey often seen as mark of pipo wey no dey civilised. China ruling Communist Party no approve am but e don become increasingly popular among young Chinese. Earlier dis year, China broadcasting regulator announce say dem dey tighten rules on wetin dem describe as ""unhealthy content"". Television and internet appearances by sports personalities and celebrities don dey restricted in cases involve tattoos and men ponytails - in some instances dem blur dis scenes from screens. Last December, one women university football match for China dey called off afta dem tell players say dem no dey allowed to dye dia hair. Di match organisers, di National Youth Campus Football League, bin tok inside statement dat time say: ""Athletes at all stages must not get tattoos, dye their hair, wear weird hairstyles, or wear any accessories, otherwise dem go dey ineligible for di competition.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-59830392 +politics Edo PDP primary: Court strike out Godwin Obaseki and Omoregie Ogbeide-Ihama case "Di Federal High Court for Port Harcourt don strike out di case wey one of di PDP governorship aspirant for di Edo state gubernatorial election Omoregie Ogbeide-Ihama bring. Justice Emmanuel Obile strike out di matter after di lead lawyer to Ogbeide-Ihama, Donald Den Nwigwe (SAN) apply for withdrawal of di matter. Special adviser to Edo state govnor for media and communications strategy, Crusoe Osagie, bin tell BBC say di suit to stop Edo state Govnor Godwin Obaseki to participate for di opposition Peoples Democratic Party primary no go stand as e dey against im right to freely associate. Dis dey follow di out of court resolution by parties for di case. Hours earlier, di federal high court bin stand down till 2:00pm for parties to settle out of court for di case of Edo state PDP governorship primary election wey go hold for Thursday, 25th June, 2020. Di governorship aspirants of the PDP, Omoregie Ogbeide-Ihama, bin drag di National chairman of PDP, Prince Uche Secondus, Emmanuel Ogidi and seven odas because dem allow Obaseki or any member of di party wey buy forms but dem no screen dem within di stipulated time frame for di timetable to contest di PDP primary. Omoregie Lawyer, Fredinard Orgbe before di hearing for di application of injunction start,  ask di court to stand down for hours so di parties fit tidy up di terms of settlement. Lawyers to all di defendants also agree with di request and no oppose di application for settlement Di presiding Judge, Justice Emmanuel Obile, grant di prayers come stand down in di interest of peace. Oga Osagie say, e no dey possible for anybody to say im dey vex becos Govnor Obaseki join PDP becos di govnor move to contest primary for PDP, dem do am according to di rules and law and principles of di party. ""As long as im no break di law of di constitution, e no get any reason for anyone else to disrespect anybody right. ""Di waiver wey di govnor get follow all di due process according to di constitution of di PDP to give am di waiver, if you tok of im joining di party, dem make sure say dem follow di rules of di party to add am for di party. So im no break any PDP constitutional rule and dat na why we know say di court go troway di decision, im tok. Di order of di Federal High Court for Port Harcourt to hear di suit wey wan stop Obaseki come, afta PDP govnorship aspirant and di House of Representative member wey dey represent Oredo Federal Constituency, Omoregie Ogbeide-Ihiama,file suit make Obaseki no follow do di party primary wey go happun on June 25, 2020. Im say only those wey buy form during di timeframe di party bin lay down suppose dey allowed to participate for di primary. Justice Emmanuel Obile, bin move di case to June 24 for hearing. ""We believe dem go allow di law to take im course and wen dat one happun, dem go allow my govnor to exercise im right. I mean im na citizen of dis kontri and im dey free to associate wit any group as long as im do am according to di law wey rule dat group,"" Oga Osagie tok. Govnor Godwin Obaseki port go PDP on Friday 19 June, afta im formally announce im decision to resign as All Progressive Congress party membership on Tuesday 16 June. We don update dis tori." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53137089 +politics Philip Shekwo: Nasarawa APC leader wey gunmen kidnap don die "Philip Shekwo, di chairman of di All Progressives Congress (APC) for Nasarawa state for north central Nigeria, don die. Tok tok pesin of Nasarawa state police command ASP Rahman Nansel confam to BBC say APC chairman for di state Philip Tatari Shekwo wey gunmen kidnap on Saturday don die. Di police tok tok pesin add say dem don carry di corpse go hospital as dem dey continue to investigate wetin happun. Na on Sunday morning BBC get news say some gunmen kidnap di state chairmo of Nigeria's ruling party. ""Di gunmen enter im house around 11pm on Saturday and na from dia dem kidnap am."" According to police. Police say dem quickly reach di scene and dem exchange gunfire with di gunmen before dem carry di late chairmo go. ASP Nansel say di way dem exchange serious gunfire with di men show say di gunmen plenti wella. No be today northern Nigeria begin suffer from security wahala from boko haram to kidnappings." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55035851 +health Update on coronavirus in Ghana: President Nana Akufo-Addo take Covid-19 vaccine, reveal roll out plan "President Nana Akufo-Addo and e vice president, Bawumia don become di first citizens for Ghana to receive di first dose of di Covid-19 vaccine on Monday. Ghana number one and number two citizens take di vaccine together wit dia spouse live on TV so as to encourage Ghanaians say di vaccine dey safe to take. Di president bin make di announcement for im 24th address to di nation on Sunday, 28 February wia im also reveal di kontri roll out plans for di vaccines. Ghana become di first kontri for di world to receive di AstraZeneca vaccines from di COVAX facility when 600,000 doses of di vaccine arrive Ghana on February 24, 2021. For im address, President Akufo-Addo tok say dem go deploy di vaccines go 43 districts wey be di epicentres of di pandemic for Ghana. Im also tok say through di National Vaccine Deployment Plan, dem don segment Ghana population into four groups, and dis go determine which section of di population go collect vaccination at a particular time. Group 1 Dis group na for ""pipo wey dey at risk and frontline state officials"". E include healthcare workers, frontline security personnel, pesin wey get underlying medical conditions, pipo wey dey sixty (60) years and above, and frontline members of di Executive, Legislature and Judiciary. Group 2 Pipo wey dey dis group na essential service providers and security agencies. E include water and electricity supply services, teachers and students, supply and distribution of fuels, farmers and food value chain, telecommunications services, air traffic and civil aviation control services, meteorological services, air transport services, waste management services, media, public and private commercial transport services, di Police Service, Armed Forces, Prisons Service, Immigration Service, National Fire Service, CEPS Division of diGhana Revenue Authority, and other members of di Executive, Judiciary, and Legislature. Group 3 Di rest of di general public na dem fall under dis group according to di President. Dat is everybody wey dey over eighteen (18) years, except for pregnant women. Group 4 Pregnant mothers and pipo wey dey under di age of eighteen (18), fall under dis group. Di president tok say dem go dey vaccinated when dem hopefully find appropriate vaccine, or when enough safety data don comot on di present vaccines dey available. Dem go make special arrangements for pipo wit disabilities wey fall within dis groups." https://www.bbc.com/pidgin/world-56235713 +politics Presidential Election Tribunal reject PDP request to inspect INEC server "Di Nigeria Presidential Election Petitions Tribunal don reject di request of di main opposition People's Democratic (PDP) to get access to di server of di Independent National Electoral Commission. Di five members of di panel strong mouth no gree di request of di PDP and dia candidate Atiku Abubakar becos of oda issues wey don join di case, wey concern dis server mata. Di judges say di tribunal no fit enta di mata of weda or not INEC use server transmit results at dis stage. For dia ruling, di tribunal say INEC don deny say dem get any server and say dem no use any electronic means take send result go any server as di petitioners dey claim. Dem say to grant dia request go mean say dem don begin enta di main issue at dis stage. ""E no go make sense,"" Justice Garba wey read dia ruling tok. Im say if di court gree PDP request, e go mean say dem don ""recognise and find out say central server dey wia all di results of di 23 February 2019 enta.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-48741767 +sports Kingsley Obiekwu: 1996 Olympic football Gold medallist say im become commercial bus driver to feed im family "Twenty-five years after im win gold for Nigeria for Olympics, ex-footballer Kingsley Obiekwu don share why im choose to become commercial bus driver to support im family. Obiekwu tori of how im bin dey drive bus for Enugu surface recently for social media afta one Nigerian spot am.Di tori of di former Super Eagles player come begin spread, e even make current Super Eagles captain Ahmed Musa donate two million naira ($4,890) to Obiekwu. Obiekwu tok say im failure to complete im education as young man bin see am miss out on opportunities. ""Afta I retire from football for 2004 and finish my coaching course for UK, I return to Nigeria for 2008, but no Premier League Club accept me, dem tok say dem no know me well as coach. ""Na one of my friend na im offer me opportunity to coach im grassroots football Academy, I work wit dem till 2012, we represent Enugu state for National Federation Cup two times, we win Enugu State League two times too and many oda championships. ""I dey earn 50,000 naira [$120] for my current job as coach with amateur football club, I get family, four of my children dey university, my last pikin dey primary school, di pay no dey enough. ""Instead of me to fold my hand dey complain, I say make I use my car begin drive taxi to get small money to support my family, na so I take become commercial bus driver."" Obiekwu tank Musa for im gift: ""I tank Ahmed Musa and all Nigerians home and abroad wey don support me dis period,I dey feel honoured say Nigerians rememba dia heroes."" Captain of Nigeria Super Eagles Ahmed Musa wey dash Kingsley Obiekwu two million Naira narrate to BBC Pidgin say e just dey scroll social media na im e see one programme by Brila FM and dem dey tok about sometin like dat. Di next day e enta Facebook e come see story about Obiekwu. ""I shout wow, na im I quickly reach out to our media men come ask for im number. ""I do am sake of say e story dey a little bit painful, we no go fit judge anybody, na so life be, I decide to do am on my own"" e tok. ""I don dey in dia shoe before, I grow up wit nothing, nothing to go out wit, we go try to get support from pipo before we fit see food chop, no be new tin, I don dey dia and know exactly how dem dey feel, I learn to give from my mama, now wey God don bless me, I like to help pipo but I no dey like to tok about am"". E advise young ones on how to manage dia finances now. ""Make young footballers try forget about di money wey clubs dey pay dem now, sake of say life dey afta football career, afta your career na dat time uou go manage wetin you get, becos dat time f you no invest you no go get anytin by month end, no salary no bonus from anywia"" ""Make di young ones learn from our old Ex-players, di situation wey dem dey now, dem bin no tink to invest back home"" ""Forget about big cars, lifestyle, designer wears, wen you retire na dia life start. Di former Super Eagles player come from Ibuzor in Delta State, southern Nigeria Im school for Agbaneme Primary school, Enugu and Union Secondary School Ogunanu. Obiekwu don play football for Udoji United for Enugu and im dey part of Nigeria team wey win Atlanta 1996 Football Gold medal. Im bin sign for ""Go ahead Eagles"" for Holland for 1995 and e play for three and half seasons. ""I no renew my contract becos dem discover say I get medical issues (Enlargement of di Heart),"" Kingsley tell BBC Pidgin. ""I fit still play football but I go dey tire quick quick na di implication be dat, so dem offer small money for di new contract but e too small so I no gree sign. ""My medical condition only limit my career, e no allow me reach my peak"". Im be part of di Super Eagles wey suppose go France 1998 FIFA World Cup but e come get knee injury. E later join Al Ahly Club for Dubai, United Arab Emirates and play for dia Premier League between 1999-2000 season. E don also play fo Al-Masry Football Club for Egypt from 2000-2001 season and e also play for seven-time Nigeria Professional football league Champions Enugu Rangers 2003 For 2004 e play for defunct Dolphins Football Club of Port Harcourt before im retire from football for 2004 after im contract end wit Dolphins. Afta retirement e travel go United Kingdom, spend four years for coaching school and get Certificate. E return to Nigeria come start im coaching career for 2008. E don coach clubs like Enugu Rangers for 2014, FC Ifeanyi Ubah for 2015, 2017-2019 as one of dia assistant coaches. Im coach Delta Force for 2016 and Union Sportif for Benin Republic 2012 and odas." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60435433 +politics Bayelsa Election 2019: Two pipo die for Nembe PDP Govnorship campaign rally "At least two pipo don die as jaguda boys scatter di govnorship election campaign rally of Nigeria main opposition party PDP for Nembe local goment area, Bayelsa State Violence burst out for many campaign ground for di state, according to tori BBC News Pidgin find out. Peoples Democratic Party PDP wey be di ruling party inside Bayelsa State bin enta Nembe town to campaign for di governorship election wey go hold on Saturday 16 November wen kasala burst on Wednesday evening. Tori be say di jaguda boys invade King Koko's Square for Ogbolomabiri Nembe as supporters dey wait for di PDP Governorship Candidate, Sen. Douye Diri and oda party members to come. Party supporters and di tori pipo bin dey trapped as dem dey look for wia to hide as gunshots begin fly upandan. Unfortunately one of di Radio Bayelsa driver wey dey drive di Outside Broadcasting Van and anoda pesin die wen flying bullets reach dem. Na security pipo wey reinforce naim come rescue di pipo wey bin dey trapped dia. Radio Nigeria tori pesin for Yenagoa Alambo Datonye tell BBC Pidgin say one driver with di Bayelsa State Radio Corporation and anoda pesin na im die for di gbege wey happen while odas wey get injury dey receive treatment for Federal Medical Centre FMC Yenagoa. Meanwhile Bayelsa State Governor, Henry Seriake Dickson don visit some pipo wey get injury during di PDP campaign attack for Nembe. Di Governor and di PDP Governorship Candidate, Sen. Douye Diri visit dem for Federal Medical Centre FMC Yenagoa as doctors bin dey treat dem. Govnor Dickson wey frown for dis attack don tell security pipo to find, arrest and drag all di pipo wey do am to face justice. Pipo for Bayelsa go vote on Saturday to elect new govnor wey go lead di state for di next four years. ""Election no be do or die affair' - NUJ Bayelsa Di Nigerian Union of Journalists NUJ for Bayelsa State too don condemn wetin happen. For statement wey di Chairman Samuel Numonengi and Secretary Ogio Ipigansi sign Di statement also ask community pipo and security agencies to make sure say tori pipo wey go dey duty during di election dey protected as dem dey play important role make sure say di conduct of di election go dey free and fair. Dem come also advise tori pipo wey go cover di election too to dey safety conscious." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50415096 +health Madagascar coronavirus cure - Wetin you need to know about di drink "Nigeria say dem dey expect to collect di Madagascar Covid-Organic herbal medicine, wey di kontri president Andry Rajoelina dey promote as cure for coronavirus. Di kontri Covid-19 presidential taskforce announce on Thursday May 14, 2020 say President Muhammadu Buhari don give instruction say make dem go carry Nigeria own allocation of di Madagascar Covid-19 syrup from Guinea Bissau. Di Nigerian goment also make am clear say di kontri go submit di drug to standard pharmaceutical tests. So far, Nigeria, Tanzania, Comoros, Senegal, Guinea Bissau, Chad, Equatorial Guinea receive di herbal cure. Launched as Covid-Organics, dem produce di drink from di Artemisia plant - di source of ingredient wey dem dey use for malaria treatment and oda Malagasy plants. Dem dey market am inside bottle and as herbal tea afta dem test am on less than 20 pipo over period of three weeks, na so di president chief of staff tell BBC. Di Malagasy Institute of Applied Reseach (Imra) don ""test am for two pipo and e don cure dia treatment"", according to president Rajoelina. Im add say ""dis herbal tea dey give results in seven days"". Oga Rajoelina say di kontri dey work wit foreign researchers to create di drink as injections. Madagascar as at Wednesday 6 May, get 158 confam case of coronavirus and 99 pipo don recover from di sickness and nobody don die, according John Hopkins University. Artemisia na herbal plant. One of di local names na Wormwood. Dis herb no dey new to pipo wey dey use am for different tins including for food and medicine. E popular with di treatment of malaria. BBC Pidgin reporter Mansur Abubakar say e common for north with di Hausa pipo wey dey call di herb Tazargade. Many pipo dey use am before for one ailment or di oda. Infact as Madagascar announce say na Tazargade dem use for dia herbal cure some mosques for Kano don tell dia pipo to make use of am for dia body as protection. 86 year old Aisha Musa wey dey stay Kano northwest Nigeria tell BBC say, all her life she dey use Tazargade herb for different things and e dey always dey by her side. ""As I dey tok to you now, Tazargade dey my side, I dey put am for water for my grandchildren to drink or burn am for charcoal for the smell to go round the house, e dey do a lot of things, cold and flu, fever and body pains.""Married women wey dey also face one problem or the other for bedroom dey also use am for north. World Health Organization (WHO) don advise pipo against di use of Covid-19 remedies wey dey untested. ""Africans deserve to use medicines wey dem test to di same standards as pipo for di rest of di world,"" na so WHO, di United Nations health agency, tok in for statement on Monday. ""Even if therapies come from traditional practice and natural, to establish if e dey work and dey safe e dey important for am to go through serious clinical trials,"" na so di statement add. Meanwhile, di African Union say dem dey discuss wit Madagascar wit aim to obtain technical data regarding di safety and efficiency of di herbal remedy. For attempt to reassure pipo and brush aside safety concerns, Rajoelina drink di Covid-Organics for di launch event and say e dey safe for children to take am. Meanwhile, President Andry Rajoelina say di reason pipo dey doubt im kontri herbal remedy for Covid-19 na because di cure ""comes from Africa"". ""If na European kontri dem discover dis remedy, shey many doubts go dey?''E tell France 24 and Radio France International inside interview. ''Di problem na say e come from Africa. And dem no fit accept say kontri like Madagascar, wey be one of di poorest kontries for di world, don discover dis formula to save di world,"" e tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52563426 +sports Israel Adesanya: Nigerian UFC 259 fighter fit become MMA legend? """For me na about di victories. Di names you collect, di scalps wey you take along di way. I wan be di guy wey take out everyone so that wen dem don tok finish dem go be like, 'na im be di greatest of all time.' Dose na di words of reigning UFC middleweight champion Israel ""Di Last Stylebender"" Adesanya. Di Nigeria-born New Zealand-based fighter bin dey tok ahead of e ogbonge fight against fearsome light heavyweight champion Jan Blachowicz, 38, wey be di headline fight of UFC 259 on 6 March. E go see di undefeated Adesenya, 31, make step up from middleweight as im attempt to become two-weight UFC champion. Irishman Conor McGregor na im be di first fighter for UFC history to win two titles afta e defeat Eddie Alvarez to add di lightweight title to e featherweight crown. Americans Daniel Cormier (light heavyweight and heavyweight) and Henry Cejudo (flyweight and bantamweight) as well as Brazilian Amanda Nunes (bantamweight and featherweight) come follow am afterwards. As Adesenya seek to join dis list of legends Nigerian MMA journalist Babatunde Koiki don explain to BBC Sport Africa wetin make Di Last Stylebender such a formidable fighter. Adesanya dey land one out of every two blows wey e attempt with either of e fists, elbows, knees or feet. Fighters wey land high percentage of dia strikes dey dey more efficient and waste less energy. And with e 80 inch arm reach coupled with e 44.5 inch leg reach for pesin wey get height of 6ft 4inches, Adesanya na nightmare from distance wit fearsome jabs. E dey take im time with e shots wey dey lead to decent 4.10 of significant punches wey e dey land per minute. Everything dey calculated. McGregor bin tok say: ""Precision dey beat power and timing dey beat speed"" dis na di perfect way to describe how Adesanya approach e fights. Pesin no dey record 15 MMA knockouts by accident. Adesanya don master di art of to dey manoeuvre im body away from attempted strikes by e opponents. Im dey absorb an average of 2.33 strikes per minute which, for tough sport like MMA, e dey pretty low. And e all dey down to im superb footwork, head movement and timing wey don help am dance out of range of one punch knockout specialists. Im also get di ability to avoid make im opponent dey take am down to di canvas wia some MMA fighters prefer to fight often as dem dey try force submissions, im don counter 86% of all attempts to put am down. Im sef no dey attempt takedowns, im dey clearly know say e success lie to dey do wetin im know how to do best: kicking and striking opponents into submission. Probably im biggest weapon na im mind. Pipo and e opponents don describe am as being cocky and arrogant. During verbal jousting sessions with e foes during pre-fight media events many don dey on di receiving end of e acidic wit and razor sharp tongue. Im social media barbs na one of a kind and e don manage to get under di skin and of many of those wey don to clash with am. Adesanya don back up every word with e fist for di octagon and im dey unbeaten." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56303990 +sports 'All good things gatz end' - Mikel Obi tok as e retire from professional football "Former Super Eagles Captain John Mikel Obi don retire from playing football at di age of 35. Di 2013 Africa Cup of Nations winner wit di Super Eagles, announce im retirement ontop im Instagram page today, 27 September, 2022. Dis one mean say im don comot hand from playing football as career kpata kpata, no more playing of club football again. Di former Chelsea player write emotional message wia e tok say evri good tin for life get di day wey e go end. ""E get one saying all good things must come to an end”, and for my professional football career, dat day na today.\n\n''I look back at di past 20 years of my career, and I must tok say I dey very satisfied wit all di tins wey I dey able to achieve and more importantly di human wey e don help shape. Di former Chelsea player add say all di tins wey im don achieve for football , no for dey possible witout im family pipo wey stand gidigba dey support am.\n\n''All dis tins for no dey possible witout di support of my family, managers, clubs, coaches, teammates wey no dey shake, and most importantly my ever-loyal fans. ''Una support me through my highs and lows, even on days wey I not live up to una expectations. I say a big thank you. Mikel Obi for im message still advice pipo wey im football don ginger to chase different dreams for dia lives, e encourage dem make dem no get up.\n\n''I go also like to encourage evribodi wey I fit don ginger one way or di oda for my dey my career to neva give up on dia dreams, for evri time you think about quitting, remind yourself why you start.\n\n''Dis no be goodbye, na di start of anoda journey, anoda chapter of my life. I look forward to weti di future get and I hope una go waka wit me. Thank you"". E write Some former and current Super Eagles player don enta Mikel Obi page as dem dey react to di news. Odion Ighalo say ""Congratulations skippo and goodluck' Ogenyi Onazi also say"" Ahhhh skippo , I miss you sha LEGEND"" Former Cote d'Ivoire and Chelsea play Solomon Kalou "" OGaaaaaaaaa I dey miss you Baba Thank You for di wonderful journey, I fancy well well dat first photo"". E tok. Former Super Eagles player and coach Austin Eguaveon also write for Twitter: Di Nigeria Football Federation (NFF) don follow tell Mikel Obi 'thank you' as di fooball governing bodi for Nigeria wish am well. For di official twitter handle NFF tweet say ""Thank you for di memories and goodluck UEFA Champions League also remember di role wey Mikel Obi play during di 2012 Champions League season wey Chelsea win. Di European football governing bodi also share video of Mikel Obi for dat match. Dem born Mikel Obi for April 22, 1987 , Jos, Plateau State, north central Nigeria. E be both Nigeria and United Kingdom citizen.E dey play Defensive midfield, central and attacking midfield. Mikel Obi start im professional football career from Nigeria wit Plateau United for October, 2004 e join Lyn FK for Norway on free transfer. Na for 2006 e comot from Lyn Fk enta Chelsea wia e spend most of him playing days. During im time for Stamford bridge, Mikel na one of di African players wey dey play well well for di club. Chelsea FC for dia official page tok say pMikel Obi play key role for dem wen dem win di 2012 Champions League. ""Afta im give di Blues over a decade of service afta we sign am as a fresh-faced 19 year-old, di midfielder lift evri major honour, wey include two Premier League titles, di Champions League and di Europa League, among odas"" Chelsea say Mikel get 372 appearances for Chelsea shirt. Mikel also play for some clubs for England like Middlesbrough and Stoke City.E also play for Chinese side Tianjin Teda, Trabzanspor for Turkey. Na Kuwait FC e dey before im retire. Mikel Obi win 2 Premier League 3 FA Cups 1 Football League Cup 1 Community Shield 1 UEFA Champions League 1 Europa League 1 Turkish League" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cgrdl18qlpgo +sports Arsenal fall flat wit 2-0 loss to PSV "Premier League leaders Arsenal miss di chance to seal top spot for di Europa League Group A as dem lost to PSV Eindhoven for Netherlands. Di Gunners only need one point to go straight through to di last 16 next March. But Joey Veerman first-time finish from 16 yards and a header by substitute Luuk de Jong - afta mistake by keeper Aaron Ramsdale on im European debut - see Mikel Arteta side lose for Europe for di first time dis season. PSV, wey former Manchester United forward Ruud van Nistelrooy dey manage also score three goals wey ref disallow. Gunners need to beat Zurich for dia final group game next Thursday for Emirates Stadium to guarantee a place in di last 16. If dem fail to win and PSV com beat Bodo/Glimt for Norway, Arsenal go play two extra games for di knockout round playoffs wia teams wey finish third for di Champions League group stage go play. FULL TIME: PSV 2-0 Arsenal 90mins: PSV clear Xhaka cross into di 18 89mins: Arsenal fans no beleive wetin dia eyes dey see for Eindovhen 87mins: Corner for PSV. Madueke put Gabriel under pressure wey hit di ball go corner 85mins: Saliba clear good cross from di right side by Til 83mins: SUBSTITUTION. Mauro Junior enta for Gapko 81mins: Arsenal don dey show a little bit of desperation. 80mins: Yellow card for Xhaka and Simons for di small fight. 79mins: SUBSTITUTION. Madueke enta for Simons, Teze enta for Branthwait while Til enta for Veerman. 75mins: Vieira rush shoot from long range and send am a little high over di bar. 73mins: SUBSTITUTION. Gabriel enta for Tierney. While Ben White enta for Tomiyasu 70mins: Cody Gakpo run too early into di Arsenal defence. Ref catch am offside. 68mins: Luuk de Jong almost score im second goal wit a header ey go wide. 67mins: Yellow card for Philipp Mwene PSV. 67mins: Yellow card for Gabriel Martinelli 64mins: SUBSTITUTION. Gabriel Jesus enta for Martinelli. 63mins: GOAL Gooal! Luuk de Jong make am 2-0 for PSV 62mins: Thomas Partey block counter attacj by PSV. 58mins: Tierney chop yellow card for foul on PSV player 57mins: SUBSTITUTION. Partey enta for Lokonga. Saka enta for Odegaard 55mins: GOAL. Veerman finally score for PSV. 51mins: Veerman attempts to score wit a first-time shot from di edge of di box. Ramsdale save am. 50mins: Xavi Simons shoot inside Arsenal penalty area but Aaron Ramsdale isave am. 49mins: Tierney sends weak shot high over di bar from di edge of di box. 47mins: Accurate pass to di edge of di box by Eddie Nketiah. 46mins: Martin Odegaard launch inaccurate corner kick into di penalty area. 45minss: SUBSTIUTION. Luuk de Jong enta for Anwar El-Ghaz Second Half Kick off: PSV 0-0 Arsenal First Half: PSV 0-0 Arsenal 45+1mins: Odegaard produce good strike from di edge of di box. Fine save by Walter Benitez. 41mins: Anoda disallowed goal afta Xavi simons goal. 39mins: Martinelli find im sef for better position inside box 18 but im finshing poor. 35mins: Good pass from Gutierezz to Gapko but Tomiyasu block am 33mins: Anoda offside for PSV. Di Gunners dey try keep Simons and Gapko offside sake of dia speed. 31mins: Sangare no dey give Odegaard chance for dat midfield. 30mins: Arsenal survive di pressue from PSV lead by Simons. 28mins: Nketiah header go wide. Good cross from Martinelli 26mins: OFFSIDE. PSV lose dia counter attack as linesamn catch El-Ghazi for offside 24mins: Corner for Arsenal. But easy catch for Benitez 22mins: Arsenal dey pass dia way around for di pitch. Currmtly wit 72% ball possession 20mins: Lokonga dey too forceful wit im tackle. Ref blow for freekick 19mins: DISALLOWED GOAL. Cody Gakpo score but referee  blow for offside 17mins: Gabriel Martinelli (Arsenal) play powerful shot towards goal, but di defender block am. 15mins: Kieran Tierney gets into good position inside di box. 12mins: Ibrahim Sangare give away foul during attacking move and di referee blow im whistle. 11mins: Cody Gakpo commit rough challenge and Marco Di Bello blow for foul. 10mins: Sioms and Gapko one-two touch dey blocked by Holding. 9mins: Viera dey penetrate from di left but im pass neva click 8mins: Xavi Simons waste an opportunity 4mins: Arsenal dey try rush PSV but dia defese dey kampe 2mins: Cody Gakpo (PSV) swing cross into di box. But t too close to Aaron Ramsdale wey handle di ball 1 min: Gae don start Kick Off: PSV 0-0 Arsenal PSV need to bounce back from dia back to back defeats to Arsenal and Groningen. Di Ruud van Nistelrooy side no dey too strong as e don show for di outings. Di club in-form foward, Cody Gakpo go wan prove im sef afta wetin happun for di last fixture for di Emirates Stadium. Arsenal don already qualify for di knock out stage of di competition but dem go wan try avoid to meet any of di clubs wey just drop from di Uefa Champions league. Mikel Arteta men dey go into dis fixture afta dia disappointing 1-1 draw wit Southampton ova di weekend. ""Last week we make di first step wey na to qualify for di next round. We need to win [on Thursday] becos we want finish first,"" e tok. Nistelrooy dey look to get boost for im squad wit di return of Noni Madueke, Luuk de Jong, and Mauro Junior. However, Yorbe Vertessen, Marco van Ginkel, Ismael Saibari, Kjell Peersman and Olivier Boscagli still dey missing sake of injury. For Arsenal Arteta tok say Marquinhos no follow di squad travel afta e fall ill in di build-up to di game while Oleksandr Zinchenko still dey struggling wit a calf injury. Emile Smith Rowe and Mohamed Elneny still dey recover from dia groin and hamstring issues respectively." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cndw903119go +politics First time voters, police tok ahead of Osun election "Some young pipo for Osun state say dia expectation dey high ahead of di governorship election for di state on Saturday. Most of di young pipo wey be first time voters say dem dey happy say dem don get di right to take dia own decision on di politics of di South western state. ""Nobody fit tell me who I go vote for. I know di problem of dis state and dis kontri and I don get right to decide wetin I want,"" 20 year-old Amdalat Abdulgafar tell BBC Pidgin. She say most of wetin dey happun dey affect her and dat na why ""I go apply for my own PVC. I apply in March dis year and I get am for May."" Ope Olayemi, wey be 19 years old say im na small pikin for 2018 wen dem do di last election for di state. E say ""I dey see wetin dey happun for di education sector. ASUU dey strike since and e no good. For Osun state we know who be candidate wey go change tins for us. ""Na day pesin I go vote,"" e add. Anoda pesin wey tok na Aishat Adetunji wey say she no go sell her vote for any amount. Di 25 year old say, ""Di money wey dem go give me no go solve my problem for the next four years."" Di Nigeria police force say dem go work wit anti corruption agency, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to reduce vote buying during di election for Osun. Muyiwa Adejobi, police toktok pesin tok wen e dey address tori pipo for di Police High command for Osogbo. For di just concluded election for Ekiti state, vote buying na di biggest challenge for di election. Di Independent National Electoral Commission (Inec) say dem go try to prevent vote buying for Osun election but police dem go work wit EFCC to reduce am well well. ""Na EFCC get di mandate to chase pipo wey dey do fraud. Police also get di mandate to arrest vote buyers but our main focus for dis election to protect evri body. To make sure say peace dey. ""EFCC get di experience and expert wey sabi trace fraud and movement of liquid cash. Our own be say we go support EFCC when fat time reach,"" oga Muyiwa tok. Sabi pipo say di race na between three parties; di PDP, APC and SDP." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0w7we7g9rlo +entertainment Jane Richards na makeup artist wey fit change her face to anybody face Jane Richards na makeup artist wey discover her talent to use make-up change her face to popular celebrity faces during di coronavirus lockdown for Nigeria. Jane say she wan use her talent to change di Nollywood make-up industry. She don use MakeUp to change her face to Nigeria President, Muhammadu Buhari face. Celebrities wey she don do dia face na Davido, Tiwa Savage, Late Chadwick Boseman and many odas. Video: Ronke Alo, Dan Ikpoyi https://www.bbc.com/pidgin/tori-54292291 +politics Pierre Nkuruziza: Who be di Burundi president wey rule for 15 years? Burundi President Pierre Nkurunziza don die of 'cardiac arrest', according to wetin goment tok for Twitter. Afta e don stay power, oga Nkuruziza suppose comot office for August. Afta which im for take di title of 'supreme guide to patriotism'. Burundi don announce seven days of mourning. https://www.bbc.com/pidgin/world-52997710 +entertainment Timilehin Adigun: Juliana Olayode, Nigerian actress accuse her former spiritual father of 'abuse' "Nigerian actress Juliana Olayode wey many pipo sabi as 'Toyo baby' and her former spiritual father and manager, Pastor Timilehin Adigun don continue to call themselves out on social media. Juliana wey become popular for her role on ""Jenifa's Diary"" - One popular television drama series for di latest video she post on her verified Instagram page on Wednesday morning say Pastor Timilehin dey behind why she comot di set of di popular TV drama plus e manipulate and sexually abuse her sister. However, di pastor for im Instagram story don quickly reply, e say im never sexually abuse anyone and e dey ready to prove am before any court or panel. Juliana wey play di role of Toyosi, best friend to di lead actor, popular actress, Funke Akindele suddenly comot for di set of Jenifa's Diary few years ago wen di series still dey hot and dis make pipo wonder why she comot suddenly. For inside di video she post on Wednesday, she give small insight into wetin happun as she don dey quiet on top di mata dis whole time. She say she for no even wan mention am if no be because di pastor for di video e post on Instagram on Tuesday tok something wey relate to Jenifa's Diary. To reply di post, Juliana say na one email wey Pastor Timilehin Adigun send mess di whole tin up. ""I no know why you mention Jenifa's diary, you want make pipo drag me for di mess you make. You just dey wicked honestly, wetin Jenifa's Dairy got to do wit passwords. You send email and mess up di whole tin. I bin no tok anytin about am, Pipo say all sort of tins to me den, some still dey tok about am till today. You mess tins up and I pay for am, who I tell? I almost go crazy wen you start to put di blame on me, as na your habit to blame me for different tins, you just never take responsibility for di tins you do. I bin tok to di pesin wey dey present di day you send di email as I bin tink say I get amnesia. I even get to chat wit di director, because ebe like say I dey go crazy...."" She tok. Di pastor no respond to dis claims. Di drama between di actress and her spiritual father and manager, Pastor Timilehin Adigun on top social media start on Tuesday 25, January wen she ask am to release di passwords of her social media accounts plus she want make e leave her alone. For inside di lengthy video she bin post earlier, she say she bin go di pastor church on Sunday afta service to ask for her passwords but e order security to throw her out. Di pastor also enta social media to reply say im no get any of her passwords and im bin manage Juliana as im own daughter. E say na im build her Youtube, Instagram and oda social media accounts and begin dey manage am since 2016 wen dem remove her comot Jenifa's diary and her passwords dey wit her, make she go find di book or di books wia she keep am. ""I give you all your passwords, go check wia you keep am."" e tok. Di pastor wey dig go dia past say im make one mistake for January 2021 wey im acknowledge and even apologise give her and post am for Instagram. E say for July she walk away from im and im wife and block am on top all platforms even afta she say she don forgive am for di mistake e make wit am. But to gain her attention back, im go her Facebook as e dey attached to im page to show her say im still get access to her Facebook page wit di thought say she go call am and dem go resolve any kwanta wey dey between dem, instead Juliana go social media accuse am say im hack her account. To reply im post, Juliana say im videos bring back sad and painful memories. Juliana Oluwatobiloba Olayode wey pipo sabi as Toyo baby and wey gain popularity for her role for Jenifa's Diary na Nigerian actress, author and purity advocate. Dem born her on June 7, 1995 for Lagos state, Nigeria. For 2017, she write one book, 'Rebirth' wey tok about her life journey. Pastor Timilehin Adigun na lead Pastor for the haven of Love church. According to im profile on Linkedin, Timi Adigun na life coach, pastor, writer, love advocate and Coordinator of MINE Teenage Ministry as wel as di president of The Love Factory. E attend Obafemi Awolowo University and get degree for Economics." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60139908 +politics Osun state APC primary: Governor Gboyega Oyetola, Moshood Adeoti and Lasun Yusuf go battle to be di flagbearer of di party "Three aspirants, di incumbent Govnor, Adegboyega Oyetola, ex Secretary to di state goment, Moshood Adeoti, and di former Deputy Speaker of di House of Representatives, Lasun Yusuf, go battle on Saturday, 19 February, for di All Progressives Congress (APC) govnorship ticket for di Osun state election. Di contest even though na in-house, party mata na one wey never comot from headlines becos of di contenders wey dey involved. Asides from dia experience wit politics, wetin make di race interesting again na di pipo wey stand behind dem for di state. As di incumbent govnor, e get advantage over di oda two aspirants. Also, im position as member of APC Caretaker National Leadership, wia e dey represent South West na also sometin wey boost im CV. Di committee wia Oyetola na member go conduct di govnorship primary. Tori be say Oyetola get strong hold on di elected APC party structure from ward to state level. Since e come on board for 2018, e don build army of party loyalists in all di 332 wards for di state and dis one fit epp im course on Saturday. Adeoti be di state chairman of Alliance for Democracy and later Action Congress before. E be experienced political figure and get strong supporters wey dey support im ambition. Osun state ex-Govnor Rauf Aregbesola bin appoint am secretary to di state government, post wey e hold till e comot from APC weeks to di 2018 govnorship primary. Reports say Adeoti don fire up im political machinery wey spread across di state, since e join di race for APC ticket, and e dey also enjoy di support of Aregbesola. Many pipo for Osun state remember Lasun Yusuf becos of im tenure as deputy speaker of House of Representatives. Many pipo for APC for di state also consider am as strong enough financially to pursue and get, not only di govnorship ticket, but also to contest and make am for di real election. Di ruling party for di state dey battle wit some crisis. E start not long afta Oyetola win for di Supreme Court, di case wey di PDP candidate for di 2018 election, Senator Ademola Adeleke bring against am. Part of di gbege na di reversal of some education policies wey Aregbesola administration start by Oyetola goment. Di policies include single uniform, school merger, renaming of schools and school reclassification. Di ex acting chairman of di party, Lowo Adebiyi suspension by APC Elders Caucus afta e form group dem call 'The Osun Progressives.' Members of TOP NA mainly supporters of Aregbesola and di group get structures for many local goment areas in di state. Di struggle for di APC ticket also bring out di state of di relationship between Oyetola and di former govnor of Osun state, wey now be di Interior Minister, Rauf Aregbesola. Aregbesola for di last rally im group hold to win support for Adeoti for Ikire, say im successor fight wit am afta e become govnor. ""I beg am for two years, I tell am say pipo must not mock us I tell am say e dey head towards destruction. I serve dis state with di whole of my heart, I also position Oyetola, so dat e fit succeed me for office. ""Wen we come to dis town (Ikire) for im campaign, rain beat us from Akire palace to dis place. E reach dat office, e claim say I be im enemy, those wey contest against am during our party primary e pull dem closer, while e dey fight me. ""All wey I tell and warn am not to do, na wetin e do. E oppose wetin I do, all di tins I do togeda wit am for eight years, e oppose and reverse dem. E tink say e fit destroy me through my work, nobody push am, e push imself. E wage war at me and refuse to listen to my begging until e get rid of me."" Aregbesola tok. ""Wen Adeoti dey angry with us, e no abuse us, wen we refuse to do wetin e want, e protest but e no ever curse us. We don realise our mistake. Dat na why we give am di ticket of our caucus."" Aregbesola add. But Special Adviser to di govor on Political Affairs, Sunday Akere, respond say Aregbesola only express personal opinion, e insist say Oyetola no fight am. Akere said, ""Our former principal only expressed personal opinion wey no one bin know. Oyetola no fight am. E declare say Oyetola tenure na im third term and e bin wan dey in charge."" E tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60382555 +entertainment BBNaija S6 eviction today: Saskay, Yousef dey evicted from Big Brother Naija Shine Ya Eye "Saskay and Yousef chop eviction on Sunday night from Big Brother Naija ""Shine Ya Eye"" TV reality show. Saskay and Yousef fall out as di first two housemates to be evicted for di night. Angel, Cross and Emmanuel also dey nominated for possible eviction from Big Brother Naija season six for di night. At least one or two if not three of these five housemates fit comot from di ""Shine Ya Eye"" edition on Sunday 19 September, 2021. Housemates wey survive Ebuka Uchendu live eviction show on Sunday night go still get chance to win di 90 million naira [about $218,596USD] star prize. As 29-year-old Yousef step out of di house, e tell Ebuka for di live show say im dey eye to do movies afta spending eight weeks for di TV reality. Saskay on her part reveal to Ebuka say she don already taya for di TV reality show. Di 22-year-old say setting up a retirement home for old pipo and her lip-gloss brand na im dey her mind after di show. Shortly after di live eviction show, Angel hala on her own say she surprise say pipo vote for her to remain. Angel hail her papa say if na so, him wey be PR pesin dey do a great job. Di BBNaija na Nigeria biggest TV reality show and most housemates wey contest dey turn celebs for di kontri. Angel, Cross and Emmanuel survive Sunday eviction las las." https://www.bbc.com/pidgin/world-58617798 +entertainment Mr Macaroni, Taaooma, odas take about meeting wit Nigeria Vice President Prof. Yemi Osinbajo wey spark reactions Popular skit-maker Maryam Akpaokagi wey pipo sabi as Taaooma don tok sorry say she honour one invitation to visit Nigeria Vice President Prof. Yemi Osinbajo for di presidential villa on Wednesday. Inside her apology statement to Nigerian, she explain why and wetin she bin intend to go do for di meeting. Taaooma explain say she bin one reject di invitation but later decide to go as she reason say e go give her opportunity to say her mind on hot issues. Taooma explanation come afta di visit begin cause reactions and become hot talking point for social media. Dis na as some Nigerians for social media hail those wey no attend and call out di di ones wey attend di meeting. Dem say dia visit to di kontri number two citizen na to promote dia skit industry, no be to speak on behalf of di youth as dem dey make pipo believe. No be only Nigerians react as some oda comedians and skit makers wey no follow go di meeting also tok dia mind ontop di mata. Popular comedian and skit maker wey no follow, Debo Adebayo wey pipo sabi as Mr Macaroni explain say im reject di invitation. For inside statement e post for social media, e explain say im reject di invitation because im no dey happy wit di political leaders and no wan dey associated wit dem. E say e dey okay if oda pipo believe say to siddon wit goment go change some tins, make nobody crucify dem sake of dat. Di Vice President bin recently host some young skit makers for di Presidential Villa, Abuja. Di team wey bin attend di meeting bin go under di platform of Nigeria Skits Industry Awards (NSIA). Some of dos wey attend include Taooma; Josh Alfred (Josh2funny); Ayo Ajewole (Woli Agba); Adebamiro Adeyanju (Mr Hyenana) and Adeoye Adeyemi Elesho (Yemi Elesho) Some of dem post on dia page how dem use di meeting to take engage di vice president on issues wey dey affect di kontri, especially di youth. Di team wey attend di meeting bin go under di platform of Nigeria Skits Industry Awards (NSIA). Some of dos wey attend include popularly known as Taooma; Josh Alfred (Josh2funny); Ayo Ajewole (Woli Agba); Adebamiro Adeyanju (Mr Hyenana) and Adeoye Adeyemi Elesho (Yemi Elesho). Meanwhile, popular human rights activist Aisha Yesufu don tell Taaooma say she no need to apologise as different ways dey to achieve something. While some social media users call out di skit makers say dem visit di presidency to promote dia skits industry awards no be tok on behalf of di youths as dem dey carry am about. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59189112 +entertainment R. Kelly dey face accuse say im abuse teenage boy wey e meet for McDonald's "US R&B star R. Kelly dey face accuse of fresh abuse allegations, e include claim wey say im get sexual relationship with one 17-year-old boy. Prosecutors allege say di singer abuse di teenager after im meet am for Chicago McDonald's for 2006. Dem want evidence of dis, and make court hear other alleged crimes wey dem no charge di singer wit during RKelly trial for August. Kelly deny say im ever abuse anyone, and im lawyers never respond to di latest allegations. Di Grammy-winner, wey im real name na Robert Kelly, dey set to face trial for New York next month on charges wey include child sexual exploitation, im make indecent images of minors, racketeering and e try to block justice. Di charges involve six women and girls wey dem no reveal dia name. Now, prosecutors go also like jurors to hear about more than one dozen other pipo dem say Kelly abuse, threaten or mistreat. Dem include one 17-year-old boy and aspiring musician, wey Kelly allegedly meet for one McDonald's and den later invite to im Chicago studio. After e offer to help di boy with e music career, dem claim say Kelly later propose and get sexual contact wit di boy while im bin still dey underage. Di prosecutors say di boy introduce Kelly to im male friend, wey bin either dey 16 or 17, claim also dey say di singer later get sexual relationship wit am several years later. Dem also allege say di star force several female sexual partners - including one minor - to sleep wit di young man as e film dem. Prosecutors say di two boys' accounts and those of others go show Kelly alleged crimes ""bin no be isolated events and bin dey part of one larger pattern"". Di judge never rule on whether dem go consider di evidence. Kelly, wey be one of di biggest R&B stars of di 1990s, don dey jail for almost two years as e dey wait trial. Im New York trial dey scheduled to begin on 9 August." https://www.bbc.com/pidgin/world-57959844 +politics US election 2020 results announcement date: See when to know if Biden or Trump don win Afta voting don close for di US presidential election, e fit take days or even weeks to find out if Joe Biden or president Donald Trump don win. For dis election, millions of Americans don dey vote by post sake of coronavirus, meaning delay fit dey to count all di votes. Dem dey usually call result on di night of election day, For dis year, na Tuesday 3 November. Different states go stop to vote at different times. Di first polls go close on di East Coast at 19:00 local time (00:00 GMT). Dem no dey too get di full count of di votes complete on election night - but enough votes go dey to confam winner. Major US media outlets go 'call' one state wen dem believe say one candidate dey lead for dia wit big gap. But at dis stage, wen dem don count most of di votes, pipo fit reason how e go be but no be final result. Di coronavirus pandemic make more pipo dey vote early whether by post or physically. Postal votes dey usually take long to count, because dem go need check and confam signature and address. Some states, like Florida and Ohio, don allow dis process to start weeks before election day, so di votes go ready for counting. For dis states, e dey possible to determine winner on election night, depending on how close di race be. About half of states go accept postal ballots wey go arrive afta election day, as long as dem postmark am by 3 November, so dem no go count some votes until days afta di election. Additional ballots fit also increase - dis na votes by people wey request one postal ballot but decide to come out to vote physically. And dem no go put dis one for di initial count, as dem go need check well, to make sure say pipo no vote two times. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54797448 +politics Tanzania: President Samia Suluhi Hassan swearing in, John Magufuli death and important facts to know about di East African nation All eyes dey on Tanzania afta di kontri swear in a new president on Friday afta di death of President John Magufuli. President Magufuli die on Wednesday from heart complications for one hospital for Der Salam. Dem swear in Samia Suluhi Hassan on Friday for inside small ceremony. Madam Hassan come from dsei mi-autonomous islands of Zanzibar and she don serve as Presido Magufuli deputy since 2015. She go be di first Tanzania female president. Dis na some facts you fit no know about Tanzania. United Republic of Tanzania Capital: Dodoma Population : 55.5 million Area 945,087 sq km (364,900 sq miles) Major languages :English, Swahili Major religions :Christianity, Islam Life expectancy: 63 years (men), 67 years (women) Currency: Tanzanian shilling Source- UN, World Bank 1916 - British, Belgian and South African sojas occupy German East Africa. Three years later, di League of Nations give Britain mandate over Tanganyika - Wey today na mainland Tanzania. 1961 - Tanganyika gain independence wit Julius Nyerere as prime minister; Zanzibar gain independence for 1963. 1964 - Two territories unite as Tanzania. 1978 - Ugandans bin temporarily occupy one piece of Tanzanian territory and, for 1979, Tanzanian forces invade Uganda, occupy di capital, Kampala, and help to remove President Idi Amin. 1992 - Dem amend dia Constitution to allow multi-party politics. 1998 - Al-Qaeda Islamist terror group bomb US embassies for Tanzania and Kenya. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56454249 +health Coronavirus tips: How Ghana dey use drone technology fight Covid-19 pandemic "Ghana start dey use drone delivery technology in de fight against di new coronavirus (Covid-19) disease pandemic wey hit de country. California based company, Zipline wey get dema drone-delivery operations for Ghana start dey fly samples for testing from over 1000 health facilities for rural Ghana go testing centres for Accra den Kumasi. Dem start dey fly some 51 samples from Omenako drone distribution centre go Noguchi Memorial Institute for Medical Research wey dey Accra from Friday April 17, 2020. Zipline CEO, Keller Rinaudo reveal say ""Zipline wan help Ghana in dema fight against COVID-19 pandemic."" ""Using de contactless drone delivery to transport COVID-19 test samples go allow de government respond to de pandemic den help more lives fast,"" Keller Rinaudo talk for statement inside. De use of Zipline drones dey increase de speed at which samples dey catch medical testing centres which dey analyse samples for covid-19. Before de use of drones, Ghana dey rely on truck delivery which dey take time. Issue of distance, road traffic den tins dey reduce number of samples wey health workers fit test. But with drones which fit travel 70 miles/116km's round trip, covid-19 testing centres dey receive samples within hours which dey help dem run more tests. Ghana Prez Akudo-Addo believe say Ghana go fit fight de pandemic if de country fit run more covid-19 tests for places. Ghana so far test some 68,000 people for covid-19 out of which 1042 people test positive for de virus, 99 recover wey 9 die." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52372336 +sports Nigeria vs Cameroon: Super Eagles Wilfred Ndidi say im no fit assure Nigerians anytin "Super Eagles midfielder Wilfred Ndidi say im no fit assure Nigerians anytin as di team go play against Cameroon for Afcon Round of 16 game on Saturday. Ndidi tell BBC afta di team final training session before di macth say all wetin dem need now na prayers from kontri pipo. Meanwhile, Super Eagles coach Gernot Rohr say make Nigeria fans expect ""big fighting spirit"" from im team against Cameroon on Saturday. Di Nigeria vs Cameroon game go start 5pm for Alexandria Stadium and di winner of dis game na im go proceed to di quarter finals of Egypt 2019 Africa Cup of Nations." https://www.bbc.com/pidgin/sport-48888159 +politics Kogi Election make El-Rufai kneel down dey beg kogites Di political stage don set as candidates of political parties don conclude dia final campaigns to woo kogites to vote dem. But di main battle for dis election, na between di candidates of di ruling All Progressive Congress, Gov. Yahaya Bello and di opposition Peoples Democratic Party, Musa Wada. Di fight no be only between di two candidates but also between di two ethnic group for di state. Di Igala pipo na dem di majority ethnic group for di state and e be like say dem dey thirsty for di seat. While Bello na from di minority Ebira ethnic group im deputy, Edward Onoja na from igala while Wada na from di majority Igala extraction. Anoda issue wey di totori pipo mind for di state na di level of development for Kogi since dem create am for 1991. Many pipo say dem need development and prosperity for dia pipo and dat one go influence how pipo go vote. Who get moni pass and influence go also determine who go win di election. Although di two candidates dey flex muscle say dem go win, di power to determine who sit on di governorship throne on Saturday na di pipo and dat is why di candidates dem dey do last minute plot to beg di voters, and if e mean to kneel down, den dem dey ready. BBC Pidgin dey ground for Bayelsa and Kogi to give you all di latest update you suppose know: Kaduna State Govnor Nasir El-Rufai and Chairman of APC Campaign Council for Kogi State Govnorship election kneel down on Thursday for public to beg Kogi pipo to forgive Govnor Yahaya Bello. Oga El-Rufai want Kogites to forgive am all di bad tins wey Bello don do ahead of Saturday Govnorship election inside di for di state wey dey North Central Nigeria. Di Kaduna Govnor wey be one of di powerful govnors for North West Nigeria say all di pipo wey dey offended by some action of di govnor, make dem sorry as di govnor still young and don make plenti mistake but e go learn from am. But di main opposition party for di state, PDP say di way El-Rufai kneel dey beg kogite show say Yahaya Bello no merit second term and e misuse di opportunity wey im get. According to INEC and Police for Kogi state, dem don ready to conduct free, fair and credible election. As at Thursday, Inec don begin move sensitive materials to di 21 local goment area to ensure say both sensitive and non sensitive materials dey ground on time for di election day. Di resident Electoral commissioner, Professor James Iorliam Apam say more than 1.4 million pipo go participate for di election as dem don dia voters card. And di head of Police for di state, Hameed Busari say police go deploy to all di 3,058 voting point for di state and ensure say no violence happun and anybody wey wan cause wuru-wuru for di elction go chop arrest or face death. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50416060 +entertainment BBNaija: Dorothy advice Ozo about Nengi "Big Brother Naija housemate Dorothy don give Ozo advice about im waka wit Nengi as im chop second strike. Biggie sama Ozo second strike on Friday night sake of im break di rule on communication by writing secret love letter to Nengi. Dorothy confront Ozo afta Biggie do di announcement say make Ozo behave like man and stop to dey allow im feelings for Dorothy make am forget wetin cari am come di house. ""You be like chicken, you suppose be like man,"" she tell am. ""Nengi dey distract you and you know,"" she tok, ""why you dey refuse to make smart decisions? If I advice you now you go still go do di same tin again."" ""From now on behave like man, you no go fit lose both ways. We dey dis house to win."" As tins be so, if Ozo get one more strike im go chop disqualification like Erica from BBNaija Lockdown House." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54128844 +health Covid-19 vaccine: Send vaccines to poorer nations now, no wait till you get surplus - Okonjo-Iweala to UK goment "Di new head of di World Trade Organization tell BBC say UK must donate Covid-19 vaccines give poor countries now now and no wait until dem get surplus. Di new head of di joinbodi Ngozi Okonjo-Iweala say na for di interest of rich countries say make all countries get di vaccine. Dis tok dey come afta Prime Minister wey remain Boris Johnson yarn say UK go dash dia vaccines wey remain give poor kontris. On Friday, G7 leaders promise to cooperate more on Covid-19. Dem agree to increase their contribution to di Covax vaccine-sharing initiative, wey go reach at least 1.3 billion doses to poor populations worldwide very soon. As she dey react to UK goment plans to donate dia surplus vaccines give developing world, Ms Okonjo-Iweala tell BBC Radio 4's Today programme say na better thing but warn say delay fit dey dangerous. ""I no think say make we wait until surplus dey wen oda pipo don already get,"" she said. ""I think say any donations wey wan come, must come now. ""Di reason dey very simple. E dey in di interest of rich countries plus di poor countries to get equal access."" G7 leaders for inside joint statement dem release afta di virtual summit on Friday say dem don join hands to increase dia committment to di Covax scheme go $7.5bn (£5.3bn). Di leaders' commitments dey come just days after UN secretary general António Guterres claim say di distribution of vaccines no dey equal and e no dey fair. Just 10 countries don administer 75% of all vaccinations worldwide, while 130 countries neva even receive one single dose of di vaccine, he tok. Manufacturing na di biggest challenge in providing di vaccines to people quickly, Ms Okonjo-Iweala tok She encourage manufacturing companies to issue more licenses in developing countries, so poorer regions go fit also dey produce di vaccine." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56138287 +politics Supreme Court ruling today in Ghana: Ghana Supreme Court throw out case of opposition leader, declare Akufo-Addo winner of 2020 presidential election "Supreme Court unanimously throw out former president John Mahama case out of de window, say errors wey de Electoral Commissioner commit during de declaration and subsequent corrections no be based in any law. Again, de justices say, de petitioner no present any relevant data to de court for de determination of dia case. De ruling as read by de Chief Justice of Ghana, Anim Yeboah talk say ""de petition is dismissed as without merit"". Lawyers for Ghana's opposition leader, John Mahama petition Supreme Court of de land say make dem order Electoral Commission to conduct second election between NDC and NPP. Dis be one of de reliefs John Mahama dey seek from de Supreme Court after dem file petition. As part of de reliefs wey he dey seek for de Supreme Court, he explain say ""based on de data contained in de declaration wey Mrs. Jean Adukwei Mensah declar, no candidate satisfy de requirement of Article 63(3) of de 1992 Constitution to be declared President-elect."" Per de 1992 Constitution ""A person no fit be elected as President of Ghana unless at de presidential election de number of votes cast in en favour be more than fifty per cent of de total number of valid votes cast at de election."" Based on dis claim say no candidate get over 50 percent of votes, de petitioner, John Mahama dey petition de Supreme Court of Ghana to declare say de results wey EC Boss Jean Mensah announce be ""unconstitutional, null den void."" But de EC bin don tok say di petition no hold water as dem say di allegation by de NDC no dey true. Ghana Electoral laws dey allow political parties to challenge election results den stuff within 21 days after de declaration of results, de NDC dey take dis course on de last day which be today." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56276323 +sports Nations League: Ronaldo go start as Sterling, Martial, Eriksen dey in action for group matches Manager Gareth Southgate say England fit play wit back three defenders on Tuesday wen dem face Denmark in dia second Nations League match. Liverpool defender Trent Alexander-Arnold dey expected to replace Kyle Walker wey dey on suspension, as e collect red card on Saturday 1-0 win over Iceland. Arsenal strongman Ainsley Maitland-Niles go also dey in action for di Three Lions. Raheem Sterling stoppage-time penalty na im gave England victory for Reykjavik on Saturday. Denmark wey England go play on 8 September bin lose dia opening match 2-0 to Belgium but Southgate say na because luck no dey Kasper Schmeichel side. For di Sweden vs Portugal game, di fitness of captain Cristiano Ronaldo dey in doubt, as im no follow play inside Portugal 4-1 win against Croatia. Di tori be say im get toe infection. But im coach Fernando Santos don confam, but whether im go start tonight game no dey clear. Meanwhile Pogba fans go miss am afta im test positive to coronavirus along wit oda team mates like Kylian Mbappe, still France get enough power for dia squad when dem take on Croatia. Dis game di same game as di 2018 World Cup final match wey France win 4-2 over Croatia to carry di cup 20 years afta dia 1998 own. Anthony Martial go look to shine, just like Antonie Griezmann - wey miss last-minute penalty against Sweden - sef go wan do. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54075843 +entertainment Sound Sultan dead: Nigerians mourn Sound Sultan death from Angioimmunoblastic T-cell lymphoma "Tributes don begin pour in for Nigerian artiste Olanrewaju Ganiu Fasasi alias Sound Sultan wey die on Sunday. Sound Sultan die at di age of 44, according to one reported family statement. Statement from one Dr. Kayode Fasasi, believed to be im brother, announce di death in di morning of 11 July, 2021. Di statement from Kayode Fasasi add say di veteran Nigerian singer die after a battle with Angioimmunoblastic T-cell lymphoma. Plenty celebrities and Nigerians express shock and sadness on di tori of im death. Those wey e interact wit am few days before im death describe dia last moment dem get together. Nigerian actor Richard Mofedamijo wey celebrate im 60th birthday few days ago, say: Sound Sultan wish am happy birthday three days before im actual birthday. Veteran musician, Daddy Showkey no believe am, e just dey shout 'na lie, na lie.' Ogbonge musician 2 Baba [2Face Idibia] wey be one of di first pipo to comment on im death say: ""Rest In Glory my brother. You go forever live for my heart. Most of dem like Basket Mouth, just use black space for dia walls to explain dia grief. Frank Edoho describe am as di ""di nicest, most humble and talented pesin you fit ever know. Rest in Peace."" Activist Aisha Yesufu say ""Moments like dis just make me wonder whether life worth am. ""Every soul go taste death. Sound Sultan don taste im own. E remain us.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-57796110 +politics Meet di candidates wey dey eye Osun govnorship seat "Stage don set for Osun residents to pick who go lead di state in di next four years. Di govnorship election dey happun on Saturday 16 July, 2022 go see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991. Na fifteen candidates dey di race to become di next govnor of di South Western state. Di current sitting govnor, Adegboyega Oyetola dey di race as im dey seek re-election into office for second term. For candidate of di main opposition party, PDP dis na di second time im go contest for Osun govnorship election. A: Akinade Akanmu Ogunbiyi AAC: Awojide Peter Segun ADP: Kehinde Munirudeen Olumuyiwa A Atanda APC: Adegboyega Isiaka Oyetola APM: Awoyemi Oluwatayo Lukuman APP: Adebayo Adeolu Elisha BP: Adeleke Adesoji Masilo Aderemi Adedapo LP: Yussuff Sulaimon Lasun NNPP: Rasaq Oyelami Saliu NRM: Abede Adetona Samuel PDP: Adeleke Ademola Jackson Nurudeen PRP: Ayowole Olubusuyi Adedeji SDP: Omigbodun Oyegoke Akinrinola YPP: Ademola Bayonle Adeseye ZLP: Adesuyi John Olufemi Adegboyega Oyetola Im be di current govnor of Osun State. Di finance expert be 68 years-old E come from Iragbiji, Boripe local goment area. E get degree in insurance and masters in business administration, di two na from di University of Lagos. Before e become govnor for 2018, e work as Chief of Staff to Rauf Aregbesola, di pesin wey e take over from. Wetin be im campaign promise? Govnor Oyetola wey dey seek re-election back into office say “ Di state try for security mata"". E say im dey plan way to reinforce di state security system and empower di police force if im enta to be govnor again. ""We get farmer cooperatives plus herders, dis na why we no get Farmers-Herders clash for Osun. E mention as part of im achievement say di Central Bank of Nigeria for Osun na im carry second position out of all di banks wey perform well for Nigeria. E tok say, “Since im become govnor, im dey up to date wit payment of workers salary especially for pensioners and im plan to continue. ""I no dey owe workers salary and I no dey owe pensioners any arrears."" Oga Oyetola say im wan continue to reform di economy of di state and empower young pipo. Omigbodun Akinrinola Oyegoke Di 58 year old architect dey contest under di flagship of di Social Democratic party. Dem born am for Osogbo for 1964 E get im bachelor and master degree for Architecture from Obafemi Awolowo University (OAU), Ile-Ife. E later get two oda masters degree for business administration and geographical information systems from University of Ilorin and University of Ibadan. Im bin serve as di deputy chairman of di Social Democratic Party (SDP). From 2008 to 2010, e serve as Special Adviser to di den govnor on Inter-Party Relations. Wetin be im campaign promise? Omigbodun Akinrinola wan focus on reviving trade and investment for Osun state if im become govnor. Akinrinola say Osun na civil service state and as goment no dey pay workers well and ontime , e no dey boost trade for inside di state. Di SDP candidate plan to change dis things if im win. Ademola Nurudeen Adeleke Di People's Democratic Party candidate na former senator wey don represent di Osun-west senatorial district between 2017 and 2019 Apart from say im be politician, Adeleke na ogbonge businessman wey come from Ede for Osun State. Di 62 year old get Bachelor degree for criminal justice for Atlanta Metropolitan State College, US. Im bin contest di 2017 Osun West senatorial by-election afta di death of im brother, Isiaka Adeleke. Im also contest and lose di 2018 gubernatorial election form Osun state. Wetin be im campaign promise? -Adeleke say di reason why im dey recontest to become govnor for Osun na sake of di bad state of roads, hospitals, agriculture for di state. Adeleke say im wan revive subsistent farming for inside di state and also empower farmers. Di Osun State PDP Govnorship candidate also touch on poverty alleviation as part of im plans if im become govnor. Yusuff Sulaimon Lasun Di 62 year old candidate of di Labour Party na Engineer Yusuf Sulaimon Lasun come from Ilobu, Irepodun Local goment area of Osun State. E get bachelor and master degrees for mechanical engineering from University of Ibadan, Ibadan and Obafemi Awolowo University. Im na former tok-tok pesin of Alliance for Democracy before and during di administration of Chief Bisi Akande. Dem later appoint am as chairman of Osun State Capital Territory Development Authority OSCTDA for 2004. Lasun na two-time member of di House of Representatives, e serve as deputy speaker from 2015 to 2019. Wetin be im campaign promise? Di candidate of di Labour party, Yusuff Lasun say im wan focus on reforming education sector for Osun state. Oga Lasun wey say im don do plenty ogbonge tins for di sector wen im be dey represent di state for di house of rep, say im plan to continue di work. Di Labour party candidate, Yusuff Lasun say im dey passionate to serve di pipo and alleviate residents from poverty. Dis na why im wan become govnor for Osun state. E also mention say part of wetin dey important for di state na to drive business for di state. Oga lasun wey say im be successful business man and promise to use im first four years for office to help di youth find business landings for di state wey go encourage dem to thrive. Akin Ogunbiyi Na politician and businessman. E dey represent Accord Party to contest for di govnorship seat. Dem born di 59 years old for Ile-Ogbo, Osun State. Im graduate wit degree for agricultural economics from Obafemi Awolowo University and get masters for business administration from University of Navarra, Barcelona, Spain. Im na associate of di Chartered Insurance Institute, London. E serve on di board of di Infrastructure Bank Plc and Mutual Benefits Assurance Plc, among oda companies. Wetin be im campaign promise? Akin Ogunbiyi say im dey plan to focus on bringing businesses wey  go bring investments come di state. Ogunbiyi tok say e wan reform Osun Education sector, revive di agricultural sector inside di state to drive di economy. Im say e plan to give Osun a new beginning if im become govnor." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw98ezz2rg5o +sports Bukayo Saka, Harry Kane and Jordan Henderson lead England to comfortable win over Senegal England book dia spot for di quarterfinal of di 2022 World Cup afta dem comfortably defeat Senegal 3-0 for di last 16. Di 1966 World Cup winners score two goals for di first half through Jordan Henderson and Harry Kane before Bukayo Saka make am three for di 57th minute. Gareth Southgate boys control much of di game despite di impressive start of di Seneglese for di first half. Di African champions bin test di Three Lions through Boulaye Dia wey test Pickford. Di quality of England shine through as Jude Bellingham find Henderson wey finish low beyond Edouard Mendy Senegal goal on 38 minutes. Wit just seconds before halftime, Harry Kane double England lead wit ruthless finish from counterattack. Saka put di game beyond Senegal before di hour mark as im chip di ball beyond Mendy afta im receive Phil Foden cross. Di victory mean say England go meet defending champions France for di quarterfinal. 46 mins - England donbegin dis second half. Dem dey lead Senegal 2-0 and dey set to qualify for di quarter-final if e end like dis. Senegal make three changes: Pape Matar Sarr, Bamba Dieng and Pape Gueye don enta replace Pathe Ciss, Iliman Ndiaye and Krepin Diatta 48 mins - Harry Kane still dey on di offensive afta im score for di first half but im cross dey cleared by Koulibaly. 56 mins - Kane again waya beta shot wey Mendy save well. 57 mins - Saka! Three nil to England as Bukayo Saka don increase di Three Lions lead. England 3-0 Senegal. Di Arsenal man produce neat finish from Foden cross to put England for comfortable position to progress. 65 mins - England coach Gareth Southgate don bring on Marcus Rashford and Jack Grealish to replace Phil Foden and Bukayo Saka. 70 mins - Senegal go send on Famara Diedhiou for Boulaye Dia. 74 mins - Pape Matar Sarr try to reduce di deficit but im freekick go wide. E no trouble Pickford for England goal. 76 mins - Kalidou Koulibaly don see yellow card for im foul on Kane. England go make substitutions. Dem don bring on Eric Dier, Mason Mount for John Stones and John Bellingham. 82 mins - Kalvin Philips don replace Henderson as England don make dia final change. 84 mins - Senegal try to cut England lead, Diedhiou header go over. Dat na Jakobs last involvement for dis match as Fode Ballo Toure don replace am. 90 mins - Marcus Rashford stretch to meet Grealish cross. Di United forward connect wit am but im shot hit side net. Di ref don add four minutes before im go blow di final whistle. 90+3 mins - Senegal get freekick to register goal for dis match. Matar Sarr shot hit di wall. Full time: England 3-0 Senegal 1 min - Senegal don take di first kick of di game as dis round of 16 match don start. 5 mins - Boulaye Dia try to force im way into di Three Lions eighteen yard box but both Maguire and Stones snuff out di danger. 8 mins - England dey try to pressure Senegal defence wit some dangerous crosses from set piece but Senegal clear di ball well from causing any danger. 15 mins - Abdou Diallo collect warning from di ref afta im bring down Harry Kane though di ref bin signal play to kontinu. 20 mins - England don get dia first corner of di match, Foden naim go take am. Stones connect wit im Man City teammate cross but im head di ball over. 23 mins - Ismaila Sarr dey ask di referee to go check VAR afta Stones hand touch di ball. Referee Ivan Barton wave im calls away come signal for goal kick. 28 mins - We don play almost half an hour, di score still remain goalless. 32 mins - Good save from Jordan Pickford wey stretch im hand to deny Dia from opening di scoring. 37 mins - Sarr no dey happy wit di ref as Kyle Walker bring am. Di Senegalese forward want make Walker collect yellow but di ref disagree. 39 mins - Goal for England. Jordan Henderson open di scoring as im convert Jude Bellingham cut back. England 1-0 Senegal. 42 mins - England look to increase dia lead as Saka find Kane inside di box wit a cross, di Tottenham Hotspur striker no keep am on target as im shoot over. 45+3 mins - Harry Kane don score im first goal for dis World Cup. England shaperly counter Senegal wit Jude Bellingham stride forward. Im find Foden wey square di ball to Kane and di striker fire di shot past Mendy. England 2-0 Senegal. Halftime: England 2-0 Senegal England lineup: 1. Pickford, 2. Walker, 5. Stones, 6. Maguire, 3. Shaw, 8. Henderson, 4. Rice, 22. Bellingham, 17. Saka, 9. Kane, 20. Foden.\n\nSenegal lineup: 16. Mendy, 21. Sabaly, 3. Koulibaly, 22. Diallo, 14. Jakobs, 11. Ciss, 6. Mendy, 13. Ndiaye, 15. Diatta, 18. Sarr, 9. Dia https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw5vg3qlnk0o +entertainment Oba Anambra Obi Cubana burial: Cubana Chief Priest oga mama burial for Oba in Anambra state make Nigerians for social media tok "Obi Cubana and Oba in Anambra State na di biggest trend on Nigeria social media. If you too dey wonder 'What is happening in Oba Anambra State' just read di gist here. BBC Pidgin don gather five interesting reasons why Nigerians dey tok about Obi Cubana mama burial. Oh well, di burial become a special topic among Nigerians as viral videos show a lavish display of wealth. Di 46-year-old Nigeria businessman even immortalise her wit a pendant and neckpiece wey worth $100,000. Di burial go leave a lasting memory as Nigerians still dey discuss am. Videos and pictures of pipo wey dey spray bundles of money for Obi Cubana mama bin circulate on social media. For one of di videos wey go viral, e show guests dey throw wads of cash at each oda, for air. Nigerian actor, Kanayo O. Kanayo also enta Instagram page display bundles of N500 currency notes wey im plan to spend for di burial. For wetin be like competition to outdo one anoda for di burial, several guests spray Obi Cubana wit 200, 500 and 1,000 naira notes. Nigerian lamwmaker, Akin Alabi also join di list of pipo wey spray money for di party say- even if as goment worker, e say im no spray pass N9,000 Actor Alex Ekubo enta im instgram page toacknowledge di display of wealth wey im see for di burial He say : I learn one vital lesson yesterday. E get three kinds of money for dis world. E get Nigerian money, E get Igbo money, Then e get ANAMBRA MONEY. You see dat last one I mention, If skin no full, no put body."" Obi Cubana reveal say im ova 240 cows from friends as support for di event. Na im celebrity bar man, Cubana Chief Priest bin first launch di trend as im buy 46 cow for im Oga, to take host guest for im mama burial. Di Nigerian socialite wey im real name na Pascal Chibuike Okechukwu use Instagram show di cows wey dem don deliver. Cubana Chief Priest also say di number of cows wey im buy represent di age of Obi Cubana. All roads leads to Oba as Nigerian celebrities, business moguls, politicians gather for di Anambra town. to attend di burial of di Obi Cubana mama. Nollywood actors Williams Uchemba, Kanayo O Kanayo, Alexx Ekubo na some of di celebs wey first land Oba. Singer Orezi also dey dia too wit di businessman. Socialite E-Money and im wife also honour Obi along wit Singer Kcee. Several celebrities, businesspeople, including Nigerian popular socialite and Forbes rated entrepreneur, Sir Uyi Ogbebor dey Oba. Real estate mogul, Dr Kennedy Okonkwo and many politicians turn out in large number for di funeral. Alexx bin share video for im Instagram page wey show as celebrities gather for table as dem make jokes while having drinks. Di funeral rites start on Thursday, July 15, 2021, wit a service of songs and Christian wake, Di burial and reception follow on Friday for one St Paul's Anglican Church, Oba Anambra South East Nigeria Di nightclub boss buy one diamond chain wit im late mother face engraved on it and e reportedly worth $100,000. He was said to have buried im mama in N30million foreign gold casket. Local tori report say na one of im friends buy di casket as gift for di business mogul Dem tok say Committee of friends & Business Associates Of Obi Cubana also raise 267,000.000. ( Two Hundred & Fifty Seven Million Naira ) for di burial. Obi Cubana wey im real name na Obinna Iyiegbu na businessman wey dey into entertainment and hospitality business. Na im get di popular Cubana Group wey also dey manage Ibiza Club. Obi Cubana career start for 2006 as im found di Ibiza Club for Abuja to satisfy fun seekers. Afta di remarkable success im make from Ibiza club, he establish Cubana, one hospitality club wey provide all-round entertainment and satisfaction for 2009. Im bin first establish Cubana for Owerri, Imo State. Today, e don spread across to various states for di kontri including Lagos, Abia and Enugu. Di nightlife boss get several mansions across di kontri wit plenti exotic cars from Mercedes Benz 4matic S40, 2 Lexus LX, Bentley and odas. Im clubs across di country dey estimated to worth over $2billion. Obi Cubana na 46-year old man from Idemili South, Anambra state - dem born am for April 12, 1975. Im go secondary school for Onitsha and later attend University of Nigeria Nsuka wia im earn Bachelor of Arts for Political Science for 1998. Obi Cubana marry im wife for 2008 and im get four children." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57872163 +sports Lagos City Marathon 2020: David Barmasai set new record to win di marathon David Barmasai from Kenya don win di 2020 Lagos City Marathon. Oga Tumo use two hour 10 mins take finish di 42km race wey start from National Stadium Surulere and end for Eko Atlantic on Saturday 8 February Im fellow kontri woman Sharon Cherop carry first for female category. Both male and female 42km runners bin dey compete for the grand prize of $50,000 while di second and third place winners go pocket $40,000 and $30,000 respectively. Dis na di fourth edition of di marathon wey start for Nigeria commercial capital city for 2016. https://www.bbc.com/pidgin/sport-51425133 +politics Tins you fit do and those wey go land you for trouble on election day for Osun Di governorship election for Osun state, South west Nigeria go happun on July 16, according to di Independent National Electoral Commission (Inec). Di 2022 election go make am di fifth time governorship election dey hold for di state since 1999. Except di incumbent governor win re-election – if anoda candidate win, e go become di fifth govnor of di state since Nigeria return to democracy. Govnor wey don rule di state under dis period na Chief Bisi Akande, Olagunsoye Oyinlola, Rauf Aregbesola and di incumbent, Gboyega Oyetola. Like Edo, Ondo, Anambra and Ekiti states, Osun dey also hold election on a day wey different from di general election. Na di 2010 Appeal Court wey remove Olagunsoye Oyinola adjust di election calendar of Osun state. Di appeal court panel wey Justice Clara Ogunbiyi lead declare Rauf Aregbesola as di real winner of di 2007 govnorship election. Di court order say make dem swear-in Aregbesola and make e start im term afresh. Sabi pipo say di race na between three parties; di PDP, APC and SDP. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp3np434ejgo +business Twitter Login: Nigeria social media shutdown cost 5,040 hours, $1.45bn in 2021 - Report "Social media shutdown for Nigeria cost di country nearly $1.5 billion US dollars. Na Nigeria di tin affect pass for di whole of Africa and second for di world afta Myanma. Myanma lose about $2.8 billion, according to one new global study on di economic cost of deliberate internet shutdown. Nigeria lift di suspension of Twitter operations for di kontri on Wednesday 12 January, 2022, afta 222-days of ban by di goment. Ethiopia na di second-most affected kontri for Africa afta dem lose $164.5 million, Sudan follow wit $151.6 and Uganda wit $109.7 million. More dan half of di 21 kontris wey experience major shutdowns bin dey inside Sub-Saharan Africa. Oda kontriss from di region on di list include; Burkina Faso - $35.9 million Eswatini - $2.9 million Republic of Congo - $2.5 million Zambia - $1.8 million Chad - $1.6 million Senegal - $323,953 South Sudan - $269,987. Last year, Sub-Saharan Africa lose $1.9 billion due to intentional social media and internet shutdown by goment. Di intentional shutdown of di internet lead to global economic loss of $5.45 billion. More dan half of these internet shutdown na part of goment effort to manage protests and elections. Oda reasons include information control during conflict, elections and coups. Dis na according to report by one UK based digital privacy and security research group Top10VPN. For Uganda, dem restrict online services seriously before di 14 January 2021 elections. E happun afta di goment order telecom companies to block access to social media platforms as a ""revenge"". For di world, research show say three out of four reasons why goment dey shutdown internet relate to human rights abuses, according to di report wey Top10VPN release." https://www.bbc.com/pidgin/world-59983772 +entertainment Valentine's day messages: 'I be Igbo, she be Yoruba but I no fit imagine life without her' Dis na di love tori of Oluyemisi Dada and Godwin Chukwueze wey totori pipo. Yemisi bin air Godwin messages for her Facebook DM from 2012 to 2020 before she finally respond one day. Yemisi wey be from di Yoruba speaking tribe of Nigeria and Godwin wey be Igbo tok about dia tori and challenge dem overcome to be togeda. https://www.bbc.com/pidgin/media-60372879 +entertainment Oscar Nominations 2021: Mank, Minari, Promising Young Woman go compete for 93rd Academy Awards [Oscars] - See full nominees list "Oscar 2021 nominations list don finally land afta many delay sake of di coronavirus pandemic. Di movies wey dey compete for best picture include: ""The Father,"" ""Judas and di Black Messiah,"" ""Mank,"" ""Minari,"" ""Nomadland,"" ""Promising Young Woman,"" ""Sound of Metal"" and ""The Trial of di Chicago 7."" Two women chop nomination for best director for di first time ever with Chloé Zhao [""Nomadland""] and Emerald Fennell [""Promising Young Woman""]. Dem go also compete against Thomas Vinterberg [""Another Round""], David Fincher [""Mank""] and Lee Isaac Chung [""Minari""]. Priyanka Chopra Jonas and Nick Jonas announced the Academy Award nominations in a two-part live presentation on Monday via global live stream. Di 93rd Academy Awards go take place from multiple locations, including di Dolby Theatre, on April 25, after dem don push back di original February 28 date. Despite di year circumstances, di Academy is determined to put on a stand-out show, one tok-tok pesin for di Academy tok. ""The Father"" (Sony Pictures Classics) ""Judas and the Black Messiah"" (Warner Bros.) ""Mank"" (Netflix) ""Minari"" (A24) ""Nomadland"" (Searchlight Pictures) ""Promising Young Woman"" (Focus Features) ""Sound of Metal"" (Amazon Studios) ""The Trial of the Chicago 7"" (Netflix) Thomas Vinterberg (""Another Round"") David Fincher (""Mank"") Lee Isaac Chung (""Minari"") Chloé Zhao (""Nomadland"") Emerald Fennell (""Promising Young Woman"") Riz Ahmed (""Sound of Metal"") Chadwick Boseman (""Ma Rainey's Black Bottom"") Anthony Hopkins (""The Father"") Gary Oldman (""Mank"") Steven Yeun (""Minari"") Viola Davis (""Ma Rainey's Black Bottom"") Andra Day (""The United States v. Billie Holiday"") Vanessa Kirby (""Pieces of a Woman"") Frances McDormand (""Nomadland"") Carey Mulligan (""Promising Young Woman"") Sacha Baron Cohen (""The Trial of the Chicago 7"") Daniel Kaluuya (""Judas and the Black Messiah"") Leslie Odom Jr. (""One Night in Miami"") Paul Raci (""Sound of Metal"") Lakeith Stanfield (""Judas and the Black Messiah"") Maria Bakalova ('Borat Subsequent Moviefilm"") Glenn Close (""Hillbilly Elegy"") Olivia Colman (""The Father"") Amanda Seyfried (""Mank"") Yuh-jung Youn (""Minari"") ""Onward"" (Pixar) ""Over the Moon"" (Netflix) ""A Shaun the Sheep Movie: Farmageddon"" (Netflix) ""Soul"" (Pixar) ""Wolfwalkers"" (Apple TV Plus/GKIDS) ""Borat Subsequent Moviefilm."" Screenplay by Sacha Baron Cohen, Anthony Hines, Dan Swimer, Peter Baynham, Erica Rivinoja, Dan Mazer, Jena Friedman, Lee Kern; Story by Sacha Baron Cohen, Anthony Hines, Dan Swimer, Nina Pedrad ""The Father,"" Christopher Hampton and Florian Zeller ""Nomadland,"" Chloé Zhao ""One Night in Miami,"" Kemp Powers ""The White Tiger,"" Ramin Bahrani ""Judas and the Black Messiah."" Screenplay by Will Berson, Shaka King; Story by Will Berson, Shaka King, Kenny Lucas, Keith Lucas ""Minari,"" Lee Isaac Chung ""Promising Young Woman,"" Emerald Fennell ""Sound of Metal."" Screenplay by Darius Marder, Abraham Marder; Story by Darius Marder, Derek Cianfrance ""The Trial of the Chicago 7,"" Aaron Sorkin ""Fight for You,"" (""Judas and the Black Messiah""). Music by H.E.R. and Dernst Emile II; Lyric by H.E.R. and Tiara Thomas ""Hear My Voice,"" (""The Trial of the Chicago 7""). Music by Daniel Pemberton; Lyric by Daniel Pemberton and Celeste Waite ""Húsavík,"" (""Eurovision Song Contest""). Music and Lyric by Savan Kotecha, Fat Max Gsus and Rickard Göransson ""Io Si (Seen),"" (""The Life Ahead""). Music by Diane Warren; Lyric by Diane Warren and Laura Pausini ""Speak Now,"" (""One Night in Miami""). Music and Lyric by Leslie Odom, Jr. and Sam Ashworth ""Da 5 Bloods,"" Terence Blanchard ""Mank,"" Trent Reznor, Atticus Ross ""Minari,"" Emile Mosseri ""News of the World,"" James Newton Howard ""Soul,"" Trent Reznor, Atticus Ross, Jon Batiste ""Greyhound,"" Warren Shaw, Michael Minkler, Beau Borders and David Wyman ""Mank,"" Ren Klyce, Jeremy Molod, David Parker, Nathan Nance and Drew Kunin ""News of the World,"" Oliver Tarney, Mike Prestwood Smith, William Miller and John Pritchett ""Soul,"" Ren Klyce, Coya Elliott and David Parker ""Sound of Metal,"" Nicolas Becker, Jaime Baksht, Michelle Couttolenc, Carlos Cortés and Phillip Bladh ""Emma,"" Alexandra Byrne ""Mank,"" Trish Summerville ""Ma Rainey's Black Bottom,"" Ann Roth ""Mulan,"" Bina Daigeler ""Pinocchio,"" Massimo Cantini Parrini ""Burrow"" (Disney Plus/Pixar) ""Genius Loci"" (Kazak Productions) ""If Anything Happens I Love You"" (Netflix) ""Opera"" (Beasts and Natives Alike) ""Yes-People"" (CAOZ hf. Hólamói) ""Feeling Through"" ""The Letter Room"" ""The Present"" ""Two Distant Strangers"" ""White Eye"" ""Judas and the Black Messiah,"" Sean Bobbitt ""Mank,"" Erik Messerschmidt ""News of the World,"" Dariusz Wolski ""Nomadland,"" Joshua James Richards ""The Trial of the Chicago 7,"" Phedon Papamichael ""Collective"" (Magnolia Pictures and Participant) ""Crip Camp"" (Netflix) ""The Mole Agent"" (Gravitas Ventures) ""My Octopus Teacher"" (Netflix) ""Time"" (Amazon Studios) ""Colette"" (Time Travel Unlimited) ""A Concerto Is a Conversation"" (Breakwater Studios) ""Do Not Split"" (Field of Vision) ""Hunger Ward"" (MTV Documentary Films) ""A Love Song for Latasha"" (Netflix) ""The Father,"" Yorgos Lamprinos ""Nomadland,"" Chloé Zhao ""Promising Young Woman,"" Frédéric Thoraval ""Sound of Metal,"" Mikkel E.G. Nielsen ""The Trial of the Chicago 7,"" Alan Baumgarten ""Another Round"" (Denmark) ""Better Days"" (Hong Kong) ""Collective"" (Romania) ""The Man Who Sold His Skin"" (Tunisia) ""Quo Vadis, Aida?""(Bosnia and Herzegovina) ""Emma,"" Marese Langan, Laura Allen, Claudia Stolze ""Hillbilly Elegy,"" Eryn Krueger Mekash, Patricia Dehaney, Matthew Mungle ""Ma Rainey's Black Bottom,"" Sergio Lopez-Rivera, Mia Neal, Jamika Wilson ""Mank,"" Kimberley Spiteri, Gigi Williams, Colleen LaBaff ""Pinocchio,"" Dalia Colli, Dalia Colli and Francesco Pegoretti ""The Father."" Production Design: Peter Francis; Set Decoration: Cathy Featherstone ""Ma Rainey's Black Bottom."" Production Design: Mark Ricker; Set Decoration: Karen O'Hara and Diana Stoughton ""Mank."" Production Design: Donald Graham Burt; Set Decoration: Jan Pascale ""News of the World."" Production Design: David Crank; Set Decoration: Elizabeth Keenan ""Tenet."" Production Design: Nathan Crowley; Set Decoration: Kathy Lucas ""Love and Monsters,"" Matt Sloan, Genevieve Camilleri, Matt Everitt and Brian Cox ""The Midnight Sky,"" Matthew Kasmir, Christopher Lawrence, Max Solomon and David Watkins ""Mulan,"" Sean Faden, Anders Langlands, Seth Maury and Steve Ingram ""The One and Only Ivan,"" Nick Davis, Greg Fisher, Ben Jones and Santiago Colomo Martinez ""Tenet,"" Andrew Jackson, David Lee, Andrew Lockley and Scott Fisher" https://www.bbc.com/pidgin/world-56404965 +politics Rabiu Kwankwaso pick Bishop Idahosa as running mate for 2023 vote Rabiu Musa Kwankwaso don pick Bishop Issac Idahosa as im running mate for di 2023 Presidential election. Kwankwaso and Idahosa go fly di New Nigeria Peoples Party (NNPP) Presidential ticket for next year polls. Bishop Issac Idahosa na native of Edo state and Christian priest E be di Bishop and Senior Pastor of God First Ministry Inc. popularly known as Illumination Assembly for Lekki area of Lagos state. Kwankwaso choice dey come afta e fail to get di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi to be im running mate. Both Peter Obi and Rabiu Kwankwaso now dey in di race on who go become di next president of Nigeria. Bishop Isaac Idahosa na di founder of GodFirst Ministries Inc aka Illumination Assembly wey dey located from Ajah, Lagos state, Nigeria. Idahosa come from Edo state but grow up for Niger State. Apart from being a pastor, Idahosa also na gospel musician. E dey married wit children. Dem born Senator Rabiu Musa Kwankwaso for October 21 1956 for Madobi village for Kano state, northern Nigeria. E study reach Phd level and get Phd for water engineering for Sharda University for India. Kwankwaso join di Kano State Water Resources and Engineering Construction Agency for 1975 and work for there for seventeen years. Kwankwaso join politics for 1992 on di platform of di Social Democratic Party. Dat same year, e dey elected as member of di House of Representatives representing Madobi Federal Constituency. E join di PDP for 1998, for 1999, contest for election and win as govnor of Kano state from 1999 to 2003. E try recontest again but lose to Ibrahim Shekarau. For 2011, Kwankwaso dey re-elected for a second term in office from 2011 to 2015. For August 2013, Kwankwaso dey among di seven serving govnors wey form di G-7 faction within di PDP. November 2013, im plus five members of di G-7 port go di new opposition party, di All Progressives Congress. On February 2022, e join di New Nigeria Peoples Party and late become di presidential flagbearer of di party for di 2023 general election. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2xn384llm7o +politics Bayelsa Governorship election 2019: David Lyon don already be Bayelsa Govnor for im mind before Supreme Court break im heart David Lyon don already be Bayelsa Govnor for im mind before Nigeria Supreme Court break im heart. Dis na fotos of wen oga Lyon bin dey rehearse for Samson Siasia Sports Stadium inside Yenagoa, just hours before tori of di court judgement from Nigeria Highest court land on Thursday. Supreme Court confam di decision of di High Court say true true David Lyon running mate, Degi-Eremienyo forge certificate give Inec. Na dat one spoil di mata. Justice Mary Odili wey head di five-man panel of judges for Nigeria highest court come declare oga Lyon main rival durind di Novemeber 16 2019 election - di PDP candidate Douye Diri as winner. On 12 November, 2019 Federal High Court for Abuja bin disqualify Degi-Eremienyo wey contest as Lyon deputy say e forge certificate give Inec. Di court rule say Degi-Eremienyo disqualification spoil di joint ticket wey di governorship candidate, Lyon, run for and win di 2019 election. Dis one mean say no show again for David and im party for now. Although pipo dey yan say dem fit make case for di Bayelsa State Govnorship Election Petition Tribunal. Normally for Nigeria, Supreme Court judgement be final and nobodi fit change am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51495090 +health Coronavirus domestic violence: Surviving lockdown wen you dey trapped with your abusive partner "Di United Nations don describe violence against women during di coronavirus lockdown as ""shadow pandemic"". Across Africa, goments, police and activists report increase in attacks on women and girls wey trap for lockdown with abusive partner or relative. So wetin you fit do if you find yourself in dis kain of situation? We ask experts and one survivor of domestic abuse to share dia advice. ""Wen you dey for inside abusive relationship, you go notice one pattern,"" Esther* tell me, as she tink back to di three years she spend married to man wey she tok say bin dey abuse her regularly - physically and verbally. ""Weekends dey always worse, because everybody dey for house. Your partner get more time for dia hands and fit get bored too. So you go see say dem wan find trouble. Dem go set you up - say something wey go make you react and den hit you wen you react. ""If two days fit make pesin dey bored enough to make dem wan hit you, imagine wetin one month or so of lockdown don cause pipo. No be just boredom dis time, na stress, na fear."" Several years don pass now since Esther leave her husband. And even though, practically, e bin dey more easier to comot dan e go be today, e still take time and courage. ''I feel say I dey place wia get bars and I no fit comot because economically, emotionally, psychologically, e hard well well - and den my children dey too. Also, your mama dey happy say you don marry, so you dey reason - keep her happy. Stay.'' For women wey wan leave dia partner now during lockdown, di challenge dey even bigger. If dem try to leave, police fit challenge dem say dem break curfew and dem fit struggle to find public transport. Many kontries don set up helplines, dey offer advice and support to victims. Demand for dia services dey high. During di first week of lockdown for South Africa, police receive 2,320 reports of gender-based violence - 37% higher dan usual. For Zimbabwe, one helpline say di number of abuse cases dem document bin triple, while Nigerian gender advocate, Dorothy Njemanze, tell BBC News say she dey worried by di rise of abuse cases for her kontri: ""We fear say if e continue dis way, we fit record some deaths before di lockdown over.'' Some African states dey take practical steps to help women. For Tunisia, wey don see five-fold increase in reports of domestic violence, di goment don set up free helpline and allocate eight shelters for victims and dia children, with more facilities on di way. For some oda place dem, many shelters don manage to stay open and volunteers dey able to help women to escape. For Zimbabwe, di Roots One Stop Shelter dey currently house 21 adults and seven children. Di director, Beatrice Savadye, say dem dey manage to rescue women from dia homes and dey also get referrals from police. For Kenya also, social worker Dianah Kamande say shelters still dey able to house women and say her organisation don already rescue 17 women for Nairobi alone. For Nigeria, although most women shelters don close as part of di lockdown, volunteers still dey able to help women escape and move in with dia relatives, according to Titilayo Vivour, di coordinator for di Lagos State Domestic and Sexual Violence Response Team. But for Ghana main safe house, di Ark Shelter, director Nana Sunnu say dem dey unable to take in new clients because of di infection risk and lack of quarantine facilities. Esther, wey survive violent marriage and dey work with fellow survivors now, say make women still call di helpline even if dem dey for kontri wia di shelters dey closed. ""Try and reach out to activists wey dey for social media, activists wey you fit trust. Call dem, dem fit still do something even for dis lockdown situation.'' Make Communities also look out for neighbours wey dem tink say fit dey exposed to violence, according to South African psychologist Nthabiseng Ramothwala. She also advise women to seek help from di pipo around dem. ''Know police officers and emergency numbers you fit call,"" she tell BBC. ""Involve your neighbours as well, tell dem signs to look out for so you to know wen to help. Give dem numbers of close relatives wey fit come rescue you."" And for those wey really fit no escape, Esther get some final advice. ""You no need to stop your voice to make someone else feel better, but for dis situation, if dem tok something wey pain you, just ignore dem. If dem annoy you, go read book, do something else to take your mind away from dem. ''If you fit survive di next one or two or three months... den do whatever you need to do. I no know if we fit call these kinds of measure solutions. Dem just be stop-gap measures. ""Right now we dey try to survive, so say wetin dem need to hear, do wetin dem need you to do. Just survive dis.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52675405 +entertainment Meet di top five winners of MBGN 2022 wey go represent Nigeria around di world Di 2022 MGBN Silverbird don hold and 24-years old Ada Eme wey be model and event planner wey represent Abia state na im win di cvrown. Officials bin announce Ada as di  Most Beautiful Girl in Nigeria (MBGN) 2022. Di ogbonge national competition shelle for Lagos on Friday, 21 October. Out of 37 bbeautiful girls wey compete for di crown, Ada beat di 36 odas to win di 34th MBGN edition to gbab di oppourtunity to represent Nigeria for Miss World. Ada Eme take over from last year winner Oluchi Madubuike. All di top five winners go represent Nigeria for di international category of di title wey dem gbab. Nigeria don win Miss World once wen Agbani Darego, di Most Beautiful Girl in Nigeria 2001 win am as di first black African to win di international title. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyex4lg3z6ko +politics South Africa president face impeachment threat over 'Farmgate' "South Africa president Cyril Ramaphosa dey face a possible impeachment threat over di ""Farmgate"" scandal. Di president chop accuse say e cover up one $4m (£3.3m) theft from im farm for 2020, including kidnapping and bribing di burglars say make dem no tok. One leaked report from independent panel discover say oga Ramaphosa abuse im position and fit don break di anti-corruption law. Im don deny any wrongdoing, and say di money na wetin e make afta e sell buffalo. Di panel don hand over dia report to di parliament, wey go torchlight am and decide weda to launch impeachment proceedings next week or not. For oga Ramaphosa, e remain less dan one month for di conference wia dem go decide weda make e contest for second term under im party, di African National Congress (ANC), for 2024. Dis incident fit damage oga Ramaphosa chance to contest election on top anti-corruption ticket. Di ANC go hold dia executive meeting on Thursday, wia e dey expected for dem to discuss di issue. Di Farmgate scandal start for June, wen one former South African spy boss, Arthur Fraser, file complaint wit police accusing di president of hiding di theft of $4m from im Phala Phala farm for di north-east of di kontri for 2020. Oga Fraser, wey be loyalist of former President Jacob Zuma, allege say di money fit be some tin wey come out through money-laundering and corruption, and accuse di president of kidnapping and bribing di burglars. To hold dat kain plenty money in dollars fit violate foreign exchange control laws. Oga Ramaphosa don confam robbery, but say di amount dem tiff no reach wetin pipo dey tok – e also deny say im wan cover up di matter. Some $580,000 wey buyers pay in cash for buffalo na im dem tiff under di sofa cushions for di farmhouse, e tok. ""I no 'hunt' for di pipo wey carry out di tiff-tiff as alleged, I no also give any instruction to any body to do any tin,"" e write for im reply to di panel report, according to AFP news agency. Di panel conclude say plenty questions dey wey di president neva answer, dem call am a ""very serious matter"". Too much informate no dey about di man wey e claim say pay di money for buying di buffalo, di panel tok, adding say e still neva collect di animals wey e pay for, two and a half years later. Di panel also tok say e dey strange say dem keep di money under sofa, rather dan inside safe until dem fit go deposit am for bank account. ""We tink say di president get case to answer on di origin of di foreign currency wey dem tiff as well as wetin di money dey for,"" di report tok. E add say: ""Di president abuse im position as head of state for am to investigate di matter, using di assistance of di Namibian president to arrest di suspect."" Namibia president Hage Geingob bin don deny say im involve for di matter. Dem born am for Soweto, Johannesburg for  1952 Detain am for 1974 and 1976 for anti-apartheid activities and launch di National Union of Mineworkers for 1982 Chairman of di National Reception Committee wey prepare for Nelson Mandela release from prison for 1990 Become MP and chairman of constitutional assembly for 1994 Move full-time into business for 1997, becoming one of South Africa richest businessmen On Lonmin board during 2012 Marikana massacre Elected ANC leader for 2017 and on 15 February 2018 becme president afta di resignation of Jacob Zuma" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2qnz53v2eno +politics PDP win all seats for Bayelsa LGA elections, APC boycott am "Nigeria main opposition party Peoples Democratic Party (PDP) don win all chairman and councillor seats for di local goment elections wey hold for Bayelsa State, on Saturday 10 August, 2019. Local tori pipo report say voter turnout bin dey low but di conduct of di elections bin dey peaceful. Chairman of di Bayelsa State Independent Election Commission BYSIEC, Dr. Remember Ogbe tell BBC Pidgin say di election hold for di 8 local goment areas for di state and na one of di best election dem don record for di state as e bin dey very peaceful.""For election wey record over 60% voter turnout, na di work of God say we do di election and no violence, nobody die, everywhere dey very peaceful and we thank God.""Dr Ogbe say 44 of di 91 political parties na im participate for di election but di main opposition party, di All Progressives Congress (APC) dey among di political parties wey no follow participate for di elections. Di BBC try to reach APC chairmo Jotan Amos for phone to try explain why im party boycott di elections, but im no respond." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49308880 +business USSD: Wetin be USSD transaction - tins you fit use am do and how di new CBN law fit affect you "Nigerians don begin reason how di new Unstructured Supplementary Data Services (USSD ) charges go affect di pocket of mobile banking users wey go now pay ₦6.98 flat fee for any transaction. Central Bank of Nigeria (CBN) and Nigerian Communications Commission (NCC) introduce dis new charge to end di disagreement between banks and telecoms operators and e go begin take effect from From Tuesday, March 16. Dis new charges according to CBN na part of di agreement wey dem reach wen di banks and telecommunication operators been meet on Monday to discuss di N42bn debt wey banks dey owe mobile operators. CBN and NCC tok say dem go collect di new USSD charge on behalf of Mobile Network Operators directly from customers' bank accounts. ""Banks no go impose additional charges on customers for di use of di USSD channel."" CBN and NCC tok for one statement. USSD mean Unstructured Supplementary Service Data wey dey allow pipo without smartphone or data or internet connection to use mobile banking through code. Dis Unstructured Supplementary Service Data dey similar to Short Message Service (SMS) but difference dey between dem. With USSD, users dey interact directly from dia mobile phones by making dia own selections from different menu's. Unlike SMS message, during USSD session, di USSD message create real-time connection. Dis one mean say USSD dey enable two-way communication of information, as long as di communication line remain open. And so both questions and answers dey happun almost di same time. Pipo fit use ussd for different purpose like;" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56426164 +politics Bayelsa, Kogi election final result: Buhari tell Nigeria main opposition PDP to accept defeat wit grace "President Muhammadu Buhari receive Governor-Elect of Bayelsa State, David Lyon for Aso Rock Abuja on Monday where im go present im sef as di tear-rubber Govnor from Nigeria ruling APC party. Afta Nigeria election office - Independent National Electoral Commission - Inec declare Yahaya Bello winner of di Kogi State govnorship elections, opposition Peoples Democratic Party - PDP don reject both di Kogi and Bayelsa results. But President Buhari wey don sama congratulobia give all di winners wey be members of im party also tell di main opposition PDP to accept defeat wit grace. Di All Progressives Congress (APC) win di November 16 Governorship elections inside Kogi and Bayelsa States, increasing di number of states wey dem dey control to 19 of the 36 states across di kontri. For di February general election, wey President Buahri take win second term, im party lose five govenorship seats, according to statement from Buhari tok-tok pesin Garba Shehu on Monday. Di time wen APC lose nobodi complain and di Buhari goment bin accept di results, so make PDP no cry say dem be victim dey attack di election office - Inec, Oga Shehu add. ""Congratulations to Govnor Yahaya Bello on im re-election. Na race well run and victory well won. I wan encourage am to use dis second term as opportunity to build on di foundations im don already lay down to improve lives of di pipo of Kogi State,"" Buhari bin write ontop Twitter. Meanwhile, di main opposition party Peoples Democratic Party and dia candidate Musa Wada, don reject di ""outcome"" of di election. Dem say no election happun on Saturday 16 November 2019 but instead na ""war against di people"" take place. Inside statement wey PDP release on Monday, dem accuse APC say dem carry police helicopters begin attack pipo wey come out to vote, and say dem use ""thugs to shoot and kill voters, snatch ballot box"". Even though Buhari say im sorry for di violence wey thugs cause during di election, di president say na ""di work of di political sponsors wey send dem"" di thugs bin dey do. Some doubt say true true Bello fit get di kain number of votes wey INEC say im get (402,222). Odas decide to give pipo di power to act like Inec. Dis account do online poll to ask pipo to judge how di elections go. Kogi State na home to over four million pipo and e get three main ethnic groups: Igala, Ebira, and Okun." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50463481 +sports Ronaldo: Juventus tell Portugal forward say im fit comot if club meet dia demands Juventus don tell Cristiano Ronaldo sey dem dey willing to sell am dis summer - but only on dia terms and condition. Portugal forward Ronaldo wey dey 36-years, still get one year wey remain on im contract. Im future don become matter wey everybody dey chook eye and dem leave am out of dia starting line-up for di club opening Serie A match wit Udinese. Ronaldo agent Jorge Mendes don tok to several major European clubs about need to sign am, including Manchester City and Paris St-Germain. Tori be say dem summon Mendes to Juventus training ground earlier on Thursday for meeting wit senior club officials, including vice-president Pavel Nedved, chief executive Maurizio Arrivabene and sporting director Federico Cherubini. Dem tell Mendes say all situations dey possible for Ronaldo, but say Juventus no go sanction di departure of player wey dem sign for £99.2m three years ago if transfer fee no dey involved. Ronaldo dey known to dey frustrated at how im transfer to Juventus from Real Madrid don come be. Instead of to compete for di Champions League, di Italian giants never make am pass di quarter-finals since di arrival of Ronaldo as dem don beat dem for di last 16 for di past two seasons. Last season, Juventus lose dia Serie A title - afta dem win am for nine years in a row - to Inter Milan and only manage to qualify for di Champions League place for dia last set of games. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58346445 +entertainment Rema: Nigerian Singer & Lady crooner break silence on Nimie wey make fans get 'pepper bodi' weda na im girlfriend "Nigerian singer, Divine Ikubor AKA Rema don clear di air say di girl wey im carry go fan date on Thursday, June 25 no be im babe. Evritin start wen Rema announce for im Twitter days ago say im go like carry one of im 'special fan girl' go date to spoil her wit enjoyment but dem go need comment wit dia picture for am to chose di lucky girl. Na so plenti girls begin 'apply' but tins shock pipo wen im announce di winner as one Nimie girl from Instagram. Na so pipo para begin accuse Rema say im do partial, say di girl wey im chose no even follow apply like oda girls. Some even say di Nimie girl na im girlfriend sake of di way two of dem bin dey love up during di date. But Rema deny am say di girl no be im girlfriend and say she follow apply for Instagram instead of Twitter wia im first post di fan date announcement. Di date wey Rema post for im Instagram stories, first start wit romantic lunch for one restaurant for Lagos wia two of dem siddon to know eachoda more. From there, im carry Nimi go boutique for shopping. Pipo head burst wen di singer tell her to ""pick anytin wey you want, I go pay"". Afta dem do shopping finish, im carry her go boat cruise come surprise her wit necklace wey im help her wear. Di two carry di date go anoda level wen Rema hold Nimi for back, 'di Titanic style'. Rema cap evritin wen im play one of music wey im neva even release for Nimi. Born on 1 May 2000 (age 19 years), di Nigerian musician wey be singer and rapper sign record deal wit Jonzing World, we be part of Mavin Records for 2019. Im rise to fame wit di release of di song ""Dumebi"" and ""Iron Man"", wey appear on Barack Obama's 2019 summer playlist." https://www.bbc.com/pidgin/53196833 +sports Bruno Fernandes don join Manchester United for five year deal "Dis na one of di longest running transfers of di window and yes but Manchester United don get dia man - Bruno Fernandes don sign five-and-a-half year deal from Sporting Lisbon. United boss Ole Gunnar Solskjaer say: ""We don dey track Bruno for many months and everyone hia dey very impressed wit all im attributes and wetin im go bring to dis team. Most importantly him na correct human being wit a great personality and im leadership qualities dey clear for all to see. United go pay initial fee of around 55m euros (£47m) for di 25-year-old, plus oda add-ons wey fit increase di overall cost to 80m euros (£67.6m). Fernandes move dey subject to im medical and agreement of personal terms. Tori be say di two clubs don dey negotiate throughout di transfer window until Tuesday wey dem get breakthrough afta reports begin fly up and down say Barcelona sef dey interested. ""Belle dey sweet me well-well say we don agree [deal] with Sporting,"" na wetin United manager Ole Gunnar Solskjaer tok. Di negotiation between di club dey good and we know say from time, dis two clubs don dey good to each oda. ""Now wey we don reach agreement, hopefully we fit settle di boy contract mata and finish im medical, hopefully we fit announce it."" Fernandes join Sporting from Sampdoria for £7.2m for 2017 but before den, im no really dey popular for im homeland. "" Wetin surprise me be say nobody really look im side until Jorge Jesus, di current Flamengo boss decided to sign am,"" na wetin Portuguese football writer Jose Delgado. ""Pipo for media dey ask why Benfica, Sporting or Porto no go for Fernandes because im be fantastic player."" Since 2017-18 season start, Fernandes don top di Portuguese Primeira Liga rankings for di most goal involvement (67), most goals outside di penalty area (9), most chances created (239), most shots (271) and most shots on target (114). And dat na before you get to di 32 goals wey im score for all competitions last term for Sporting or di 14 goals im score for 28 matches wey im play for club and country dis season. Fernandes na di shinning light for Sporting, even though im bin struggle and e help Portugal to win Nation League for June 2019 - di big question now na whether im fit deliver for United? Na good player wey get potential to grow,"" na wetin Italian football writer Danielle Vieri tok. Wetin im don do for Portugal don show say if fit do di same for bigger stage. Di pressure go increase, im opponents go dey stronger and im team-mates go dey better. ""I no think say I fit say im don prove im self for di big European league yet but dat na di challenge. For Italy, im do well. For Portugal im shine wella, so now na di right time to buy dis kain player.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51318700 +health Covid-19 Vaccine: Why South Africa put Oxford-AstraZeneca vaccination on hold afta dem order one million doses "South Africa don put on hold dia roll-out of di Oxford-AstraZeneca vaccine afta one study show ""disappointing"" results against di new Covid variant. Scientists say di strain account for 90% of new Covid cases inside South Africa. Di study, wey involve around 2,000 pipo, see say di vaccine offer ""minimal protection"" against mild and moderate cases of Covid-19. South Africa don receive 1m doses of di AstraZeneca jab and bin suppose start to dey vaccinate pipo by next week. For one online news conference on Sunday, South African Health Minister Zweli Mkhize say im goment go wait for further advice on how best to proceed with di Oxford-AstraZeneca vaccine in di face of dis findings. Na di University of di Witwatersrand carry out di trial but dem never do peer review yet. In di meantime, e say, goment go offer vaccines wey Johnson & Johnson and Pfizer produce in di coming weeks. ""Unfortunately, di AstraZeneca vaccine no dey work against mild and moderate illness,"" Prof Shabir Madhi, wey lead di study, tell di briefing. E say di study never dey able to investigate di vaccine power to prevent more serious infections, as participants get an average age of 31 and so no represent di demographic wey dey most at risk of severe symptoms from di virus. Meanwhile, Prof Sarah Gilbert, Oxford lead vaccine developer, say di vaccines suppose still protect against severe disease. She say developers dey likely to get modified version of di injection against di South Africa variant, also known as 501.V2 or B.1.351, later dis year. Experts say dem fit redesign and tweak vaccines to be a better match for new variants in a matter of weeks or months if necessary. Early results from Moderna suggest say vaccine still dey effective against di South Africa variant, while AstraZeneca say dia vaccine provide good protection against di UK variant wey dem first identify for di UK. Early results suggest say di Pfizer-BioNTech vaccine protect against di new variants." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55977256 +entertainment Omah Lay Uganda: Nigeria dey do everi to free Omah Lay, Tems arrest in Uganda - Abike Dabiri "Nigeria Mission for Uganda dey do everything possible to free musicians Omah lay and Tems wey chop arrest for di East African kontri since on Sunday. But Uganda authorities dey insist say dia laws must be obeyed, Abike Dabiri, di Chairperson of Nigerians in Diaspora Commission [NIDCOM] wey reveal dis one, add say Di Nigerian Minister of Foreign Affairs Geoffrey Onyeama don also dey on di matter and NIDCOM also dey in touch with dia Lawyers, she add. Tori be say Uganda police arrest Omah lay and Tems ontop accuse say dem break Covid-19 rules. Authorities hand cuff and remand Omah Lay and Tems for prison ontop accuse say e break dia Covid-19 rules. Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openyi alias Tems and Muyiwa Awoniyi appear for Magistrate court on Monday 14 December ontop charge of ""negligently doing acts wey fit spread infectious diseases"". Four Uganda citizens also dey charged wit di Nigerians, di police bin confam." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55313143 +entertainment Sam Smith and Burna Boy song 'My Oasis'- See wen dem go drop di single "Ogbonge British Singer Sam Smith announce on Wednesday July 29 say im go release brand new single 'My Oasis', wey go officially come out on Thursday (July 30) by 7.20pm BST, di single go feature Nigerian superstar Burna Boy. For Burna Boy dis collabo dey come afta di Jerusalema remix with Master KG for June. Smith post black-and-pink video of di instrumentals of di song with di Nigerian singer for social media. Dis go be im first new song since im release duet with Demi Lovato 'I'm Ready' for April. Tori be say e dey come ova one year since im release di song 'How Do You Sleep?', wey bin suppose appear for Smith upcoming album wey im postpone. 'Money On My Mind', 'Stay with Me' and di Spectre dem song 'Writing's On the Wall', wey win Oscar in 2016 na some of Sam Smith hit songs. Di British singer dey worth an estimated £33m. Fans dey hail Burna Boy for di latest collabo with Sam Smith. Even though dem neva release di song, some of dem believe say e go be hit. Di British singer tweet say ""so much love for you Burna. Dis go be fun"". Burna reply am back say you ""killed it Sam."" Dis no be first time wey Burna dey collabo wit foreign musicians, e don make music with Beyonce, Stormzy and Ed sheeran." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53590680 +sports Lionel Messi contract: What next for Messi? - Dis na wetin we know "One of di greatest player for di world don officially become a free agent. 12 months afta im aborted attempt to leave Barcelona, Lionel Messi dey out of contract now. Di Argentine superstar deal expire for midnight and despite months of rumour and speculations, e neva commit to any extension. Discussions over a new contract dey believed to dey go on, wey mean say Messi fit decide to stay for Nou Camp. But for now, e dey available for free. Barcelona still believe say Messi go eventually sign a new deal, but im status as a free agent go generate concern among di club fans and management. Messi wey become free agent now don add a new layer of complexity to di situation. If Barcelona re-sign di player, e go have to dey registered wit La Liga as a new signing. As a new signing, Barcelona go need find a creative solution to fit Messi into di framework of La Liga financial regulations. La Liga president Javier Tebas don already warn Barca say dem must bring dia money down, or dem no go fit register Messi ahead of di 2021-22 season. Di 34-year-old don dey linked wit moves to go Paris St-Germain and Manchester City, where e go dey reunited wit im former boss for Barcelona Pep Guardiola, as well as America Major League Soccer. E currently dey Brazil where e dey play for Argentina for di Copa America and e don become di most-capped player wen e make im 148th international appearance against Bolivia on Tuesday, e score two times and set up another in a 4-1 win. 25 August 2020 - Messi send message give di club say im wish to exercise one clause for im contract, wey go allow am leave for free wit immediate effect. 4 September 2020 - Messi say e dey stay wit Barcelona because e dey ""impossible"" for any team to pay im 700m euro (£624m) release clause, wey di club insist say must happun. 27 October 2020 - Barcelona president Josep Maria Bartomeu, wey get issues wit Messi on top im failed transfer request, resign. 28 December 2020 - Messi say im hope to one day play for di United States, but e no dey sure of im future wen im contract end. 31 January 2021 - Barcelona say dem go take ""appropriate legal action"" against Spanish newspaper El Mundo afta e publish details of Messi contract, wey worth £492m over four years. 16 May 2021 - Manager Ronald Koeman say e hope say Messi no play im final home game for di club afta a 2-1 defeat by Celta Vigo. 22 May 2021 - Believe dey say Paris St-Germain dey chook eye for contract situation. 28 May 2021 - Barcelona president Joan Laporta tok say new contract for Lionel Messi is neva ready but things dey go on well. 1 July 2021 - Messi Barcelona contract expire and e become a free agent." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57676705 +politics 'Buhari don leave di leadership of Nigeria for two tok-tok pesin hands' - Uche Secondus, National Leader of di People Democratic Party (PDP) "Di National Leader of di Nigerian opposition political People Democratic Party (PDP) Uche Secondus don hala say di All Progressives Congress dey run goment of exclusion. E claim say President Muhammadu Buhari dey absent from duty and di various factions of leadership for di goment don make say no collaboration dey for di executive arm of governance. For di World PDP Press Briefing wey shele on Monday, May 3, oga Secondus add say, ""e be great disservice to di Nigerian people make oga President abandon im Presidential duties put for di hand of two media tok-tok pesin dem, wey dey release annoying press statements"". E add say Nigerian wahala of insecurity na wetin dey make global organisations dey abandon di kontri go neighbouring kontris to dey do business. Solutions to Nigeria problems Di political party use di event take tok some solutions wey dem say go fit take solve di wahala wey dey happun for di kontri. Oga Secondus call for di creation of state police, empowerment of armed forces and foreign help to cure di security palava. Im also say make dem quick-quick bring every pesin wey get hand for di kasala for di kontri to book. Oga Secondus bin also call for di sack of Isa Pantami on top say im be ""self-proclaimed bigot wey bin happy ova di death of citizens of oda faiths because although im don give up im past beliefs no mean say di odas wey im help recruit don give up dia beliefs join."" Im also call on President Buhari to speak to di kontri ova wetin dey happun because na political malpractice say im no dey tok any tin or do anything ontop issues wey dey ground. On di mata of economy , oga Secondus ask di federal goment to find way to stop to dey borrow money so dem no go sell di future of di youhs to dey clear gbese." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56964878 +entertainment """Regina Daniels"" mama ""Rita Daniels"" bag 'peacemaker' title wit surprise from Prophet Odumeje AKA Indabowski" "Regina Daniels mama, Rita Daniels don collect chieftaincy title as 'peacemaker' for her home town. Rita Daniels collect di chieftaincy of Ochiudo of Ogwashi-Uku Kingdom for Delta State. She collect di title for Ogwashi-Uku wey be her home town. Di movie producer follow enta social media to thank God for di success of di event. Regina Daniels, her pikin wey bin dey for di installation, do video for di event wey show popular and controversial Anambra based pastor, Prophet Chukwuemeka Ohanaemere wey dey popularly known as Indabowski for dia. Tori be say e go her house to go surprise her afta di event. Di title wey dem give am Ochiudo mean say she be ""peacemaker"" of Ogwashi-Uku Kingdom." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54396333 +politics Nigerian Ministerial review and wetin Buhari tell im ministers as im score dia performance On dis day, wey mark one year and a week of wen di Ministers of di Federal Republic of Nigeria start dia work on top di second term of di President Muhammadu Buhari administration, dem come togeda to day to tok wetin dem don achieve ova di past one year. For presidential speech wey vice president Yemi Osinbajo tok e tok say di administration bin help di economy to recover before pandemic, improvement of transport infrastructure, support for agriculture and social investment programmes to empower di youths. Dem tok say for di event dem go focus on three tins mainly For di speech oga Osinbajo also explain wetin cause di rise in di price of fuel. E tok say for di height of di epidemic for March dem stop to dey regulate di prices of di petroleum products. Dat means say na di market go dey dey determine di price of di petroleum products. So, wen di global price bin dey at all time low, na im Nigerians benefit but now wey be say be say di prices of fuel for world don dey adjust na im make fuel for Nigeria add price. E also add say Nigeria no get di money to dey pay extra alias subsidize fuel prices on top say di goment get 60% less revenue today. Tori be say dis new price of 162 Naira still be di lowest for di West and Central African regions. On di increase in money for electricity, oga Osinbajo, wey represent Buhari for di meeting, tok say dem no fit afford to subsidize di tariff shortfalls if di industry afta dem don spend 1.7 trillion Naira so far to support di industry. But, di goment through dia regulation bodi NERC don approve make dem make adjustments in pricing of di tarriffs only with beta provision of electricity. Dis one mean say na only pipo we dey get minimum of 12 hours with light na im dem go fit increase price. E also tok say even with di pricing change, Nigerian still be one of di cheapest wen you compare am with oda kontris for Africa. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54040074 +sports Algeria vs Nigeria: How Algeria come from behind to beat Nigeria for dia International friendly match Di Desert Warriors of Algeria on Tuesday night beat di Super Eagles of Nigeria 2-1 to win di International friendly match Di 2019 Africa Cup of Nations winners come from behind and defeat di Eagles wey first secure dia first goal 9 minutes into di match. Na Terem Moffi first give di Nigerian team di lead for d match. Franxck Onyeka foul for inside penalty area give di Algerian di chance wey dem need to equalise Moffi goal and Mahrez no take am play at all as e net di penalty. Moffi try again at 28 minutes as e shoot anoda goal pass di Algerian post but dem rule di goal offside. Youcef Atal seal di lead for Algeria at for di second half of di game as di Eagles bin struggle to match up but dem no fit. Dis na di two sides first meeting since dem bin meet for international friendly match for October 2020. For dat game di Desert Warriors bin win di Super Eagles 1-0 and di West Africans neva defeat dia opponents today for dia last three matches. Kick off 6 mins Corner kick for Nigeria Goallllllll 9 mins Terem Moffi score di first goal for Nigeria 28 mins Goal.... Moffi Again... Nah, linesman rule am offside 31 mins better save by Zeghba for Algeria 34 mins free kick for Algeria 39 mins Franck Onyeka chop yellow card as e commit foul inside Penalty area 40mins Penalty to Algeria 42 mins Goalll Algeria 1-1 Nigeria Mahrez net di penalty 45 mins + 3' mins first half end Algeria 1-1 Nigeria Kick off 45 mins Substitution Algeria take Nabil Bentaleb replace Adem Zorgane. 60 mins Goalll Algeria 2-1 Nigeria Youcef Atal shoot long shot pass di players 65 mins Algeria use Adam Ounas subtitute Youcef Belaïli afta e score 68 mins Nigeria replace Ademola Lookman wit Saviour Godwin 72 mins Terem Moffi comot for Taiwo Awoniyi 77 mins Referee award yellow card to Zerrouki for bad foul 90 mins + 2 mins Nigeria Calvin Bassey chop yellow card for foul 90 mins + 4 mins Second Half end Algeria 2, Nigeria 1. 23 Uzoho, 2 Aina, 13 Akpoguma, 21 Bassey, 3 Sanusi, 4 Onyeka, I18 wobi, 14 Iheanacho, 7 Lookman, 15 Simon, 11 Moffi, 1 Zeghba, 20 Atal, 2 Mandi, 5 Touba, 21 Bensebaini, 6 Zerrouki, 19 Zorgane, 22 Bennacer, 10 Belaili, 7 Mahrez, 13 Slimani BBC Pidgin go bring live updates of di match as e dey happun for di Oran Olympic stadium. E go start by 8:00pm https://www.bbc.com/pidgin/tori-63054474 +entertainment Wizkid pay tribute to Davido late son during performance for New York "Nigerian superstar singer, Ayodeji Balogun wey dey popularly known as Wizkid don touch di heart of plenti fans afta e pay tribute to Davido late son,  Ifeanyi Adeleke Jnr. Wizkid give Davido shoutout for im soldout concert wey dem recently do for Madison Square Garden, New York on Wednesday. During di concert, Wizkid official Disc Jockey play Davido debut hit song, “Dami Duro”, for di venue. For di video wey don go viral for social media, one voice wey like Wizkid own say; “Davido we love you, OBO we love you”… Dis one na for Davido"" as di singer music dey play loudly for di concert. Di video of di concert wey dey trend also show moment wen di venue go into brief darkness to further mourn di tragic death of di 3 year old. Di excited audience wey join too begin sing Davido ""Dami Duro"" song as e dey play. Nigerians for social media don begin react and shower praises give Wizkid for im support and love for Davido. Recently, di popular Nigerian Afrobeat star, David Adeleke Aka Davido lost im three year old son. Police for Lagos state bin come arrest eight of Davido domestic workers. Benjamin Hundeyin  say di incident happun on Monday night on 31 October and na one of di domestic workers go report for police station. Later on 5 November, police come reveal di result of di autopsy wey day di cause of death of Ifeanyi death na ''drowning''. Police later release some of di domestic staff. Di police tok-tok pesin tell BBC Pidgin say dem don transfer di two suspects wey dey dia custody go di state criminial investigation department (SCID) Yaba area of di state for further investigate. Ifeanyi be di son wey im get wit im Fiance, Chioma Rowland." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c13kln48nlpo +politics INEC: Nigeria election office don remove 74 political parties from dia register Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (Inec) don don remove 74 political parties from dia register. Inec Chairmo Mahmood Yakubu wey announce am give tori pipo for Abuja tok say di deregistration dey according to di Nigerian constitution as the parties no meet di commission requirements and with dis new decision na 18 political parties remain. Mahmood explain say na 74 political parties no satisfy di requirements of di Fourth Alteration wey dey inside di constitution but one of di political parties, Action People Party (APP) don carry dem go court and dem don get order wey no go allow make di commission deregister dem. Before di 2019 general elections, Nigeria bin get 191 political parties, another one join after di elections wey make am 192. Di constitution give INEC power to deregister political parties if dem fail to meet di following requirements: For di Edo and Ondo states governorship elections and bye elections wey go hold for di kontri, INEC don fix di date. Di tenure of di governors for Edo and Ondo states go end for di 12th November 2020 and 24th February 2021 respectively, di commission don fix Saturday 19th September 2020 as di date for Edo election and Saturday 10th October 2020 for Ondo state. Bye elections go dey for three constituencies as a result of di death of some serving members of national and state assemblies for Niger, Kwara and Sokoto states, di bye elections go hold simultaneously on 14th March 2020. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51404017 +sports Europa League: West Ham vs Geng line up as Moyes celebrate 1000th game West Ham manager David Moyes go celebrate im 1000th game in management as West Ham face Genk on Thursday. Moyes landmark game dey come in a relatively low-key Europa League group game against Genk. Di 58 year old manager like am like that as e no want any fuss. A win for West Ham go guarantee im side a place for di knockout stages of di Europa league. West Ham don beat both Manchester clubs before dem reach di EFL Cup quarter-finals, and victory against Liverpool on Sunday fit take dem as high as second for di Premier League. West Ham boss David Moyes bin make six changes to di side wey beat Aston Villa 4-1 for di Premier League for weekend wit goalkeeper Alphonse Areola, defenders Vladimír Coufal, Craig Dawson and Issa Diop, midfielders Mark Noble and Arthur Masuaku and forward Manuel Lanzini coming into di XI. Declan Rice and Michail Antonio keep their spots, even as di Hammers go host Liverpool on Sunday. West Ham XI: Areola, Coufal, Diop, Dawson, Cresswell, Masuaku, Noble, Rice, Lanzini, Benrahma, Antonio. Kristian Thorstvedt, the son of former Tottenham and Norway goalkeeper Erik, starts in midfield for the hosts. Genk XI: Van devoordt, Arteaga, Lucumi, Mujaid Sadick, Muñoz, Thorstvedt, Heynen, Ito, Hrosovsky, Paintsil, Onuachu https://www.bbc.com/pidgin/tori-59166483 +entertainment Whitemoney BBNaija biography: Whitemoney win Big Brother Naija season six, Liquoros come second "Whitemoney don win di big brother Naija season 6 reality TV show afta 10 weeks inside di 'shine ya eye' house. Whitemoney wey im real name na Hazel Oyeye Onou beat ova 20 housemates wey participate for di sixth season of di show. E don be di 6th winner for di ogbonge show and join past winners like: Katung Aduwakwey win first edition for 2006, Efe Ejeba (2017), Miracle Ikechukwu (2018) and Mercy Eke (2019), Laycon 2020. Whitemoney dey go house wit di grand prize of 90 million naira. 29-year old Whitemoney come from Enugu state say e be businessman wey dey into import of shoes. Multitalented Whitemoney describe imself as open-minded ""jolly good fellow"" wey like to catch fun. Whitemoney bin establish imself as a fave for di ""Shine Ya Eye"" House and one of im most endearing features na im kitchen presence. Right from di first week of di Season, Whitemoney make am a duty to make sure imself and im fellow Housemates dey well fed. Whitemoney during im stay for di house tok a lot about im music career and im love for music. E don always tok say BBNaija platform na very important platform to push im dreams and career. Whitemoney don walk away wit di ogbonge grand prize of N90m. Di N90m grand prize include N30m cash prize, cash in Abeg digital wallet, bitcoins courtesy Patricia, one two-bedroom apartment courtesy RevolutionPlus Property, a top of di range SUV from Nigerian automaker, Innoson Motors and a trip for two wey Travelbeta package. We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58781283 +entertainment BBNaija strikes: Erica, Kiddwaya, Ozo and Tolanibaj collect warning from Big Brother - See di reason why "Big Brother punish four housemates inside di lockdown season 5 house today. Di housemates na Erica, Kiddwaya, Ozo and TolaniBaj. Biggie give dem strike on eviction Sunday and di day im return back to di house afta one week of absence. Ozo and Erica na im collect di first strike of di season. Biggie punish dem say dem dey whisper. Den, Erica, Kiddwaya and TolaniBaj collect strike also because dem break di Head of House (HoH) lounge rules. Erica sake of say she spend di night for di HOH lounge, while TolaniBaj spend di night for Prince bed. As e be so, Erica don get two strikes. If she collect anoda one, Na bye-bye to her be dat. According to Biggie rule, housemates no suppose communicate without cameras/microphones recording the communication (e.g. to dey tamper with microphones, writing secret messages, to dey whisper or move mouth without talking.) or if dem try to tamper with or cover recording equipment or if housemates communicate for secret code - Big Brother get di right to issue a strike or disqualify di Housemate."" Also, housemates no suppose sleep for di HoH lounge except di HoH and im deputy. Punishment for di whole HouseFor dia bad behaviour in di House, Biggie also punish di rest of di Housemates. Di housemates no go get hot water for di bathrooms for di next few days. Biggie add say dia attitude go determine how long dis punishment go last. Henceforth, dem no dey permit to use di pots, pans or kettles to boil water wey dem use di bathrooms." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53883058 +business Emirates to resume flights to Nigeria: FG lift ban on Dubai main airline operations "Nigeria goment don comot di ban dem put on Dubai main airline, Emirates. Di Minister of Aviation, Hadi Sirika wey announce am inside statement wey di Director of Public Affairs for di Ministry of Aviation, James Odaudu sign say ""from Friday, 26 November 2021, all di conditions on Emirates airline don dey lifted and di airline go fit operate for Nigeria now."" E say di move na in response to di cries of Nigerian travellers and afta serious negotiation wit di United Arab Emirates (UAE), Emirates Airlines home kontri. D minister add join say UAE don also remove all travel restrictions on Nigerians. ""Today we don receive communication from UAE wey remove some of di conditions of travel wey we bin get concerns about. "" E tok. Nigeria goment bin earlier ban Emirates make e no fly enta Nigeria sake of discriminatory policies wey relate to Covid-19 protocols wey UAE put on Nigeria. Dis na afta Emirates announce another suspension of flights to and from Nigeria from Monday June, 2021. Emirates flight ban on Nigeria come barely 48 hours afta UAE announce plans to resume flights wey go connect Nigeria to Dubai. ""In line wit goment directives, passenger flights to and from Nigeria (Lagos and Abuja) dey suspended wit effect from 21 June 2021 until further notice."" Since 4 February, 2021 Emirates Airlines stop to dey airlift Nigerians to Dubai from Abuja and Lagos airports. Di ban na sake of di refusal by di Presidential Taskforce on Covid-19 [PTF] to allow di airline conduct rapid test for coronavirus. Di airline make dis test compulsory for dia passengers, four hours before dem board dia flights. But di arrangement no go down well wit Nigerian Federal Goment authorities. Passengers from Nigeria to Dubai:" https://www.bbc.com/pidgin/tori-59443137 +politics Boris Johnson win confidence vote - See wetin e mean "Boris Johnson don win one confidence vote of Tory MPs by 211 to 148. E mean say e go continue wit im job as prime minister. Di result dey announced by chairman of di 1922 Committee Sir Graham Brady. Conservative MPs bin dey reason weda dem wan replace Prime Minister Boris Johnson. Dem hold di vote between 18:00 and 20:00 BST on Monday. Some Conservative MPs bin drop letters to call for Oga Johnson to resign. Pressure on di prime minister grow afta publication of details of Downing Street parties wey break Covid rules. One report, by senior civil servant Sue Gray, say many of di gatherings ""no suppose dey allowed"". Attempt by Conservative MPs to remove dia leader dey known as vote of confidence. For vote to hold, at least 15% of Conservative MPs need to to write letter say dem no longer support dia leader. At di moment dis dey work out as 54 MPs (out of 359). For Boris Johnson mata, dem send dia letters to Sir Graham Brady, di chairman of one group wey dem dey call di 1922 Committee, wey represents dem. On Monday, e bin say no enough letters dey for vote to shelle. To win, Oga Johnson bin need more Tory MPs to vote for am to continue, rather dan to dey replaced. So, if every Conservative MP take part, Oga Johnson bin need 180 votes (half im MPs, plus one). Tory MPs no go need to tok how dem vote, but some go choose to do so. As e win, Oga Johnson go continue as Conservative Party leader and prime minister. Under current rules, Tory MPs no go dey allowed to hold anoda no confidence vote for one year. However, e bin get tok-tok say some fit try to change di rules, to hold anoda vote soon. Wen dem ask Oga Brady about am, e say ""technically, e dey possible"". E also dey possible say if Oga Johnson win by only few votes, dem fit tell am to tink twice about weda e get enough support to kontinu. If Oga Johnson bin lose e for need to resign. Di timetable for di election of new Conservative leader go come dey set by di 1922 Committee. Di winner go also become prime minister. Dis wan mean say new PM fit dey chosen without general election. Di reason be bicos UK voters elect one party to govern, not individual. In order to stand for leadership contest, candidates need di support of eight oda Tory MPs. If more dan two candidates stand, Tory MPs go hold several of votes until only two remain. Wen two MPs remain, Conservative Party members around di kontri - no be just MPs - go vote for di winner. If all but one of di candidates withdraw (as e bin hapun wen Theresa May become leader for 2016), di candidate wey remain go become Conservative Party leader." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61698057 +entertainment Wizkid 'No Stress'- Eviritin you suppose know about Starboy new single Ogbonge Nigerian singer Wizkid drop im new single 'No Stress' on Thursday September 17 and di song dey totori im fans. Di singer announce di release of im single for social media and di song na top trend for twitter. Dis na im second solo single for 2020. Wizkid new single wey im title 'No Stress' na follow-up to im last single, 'Smile' wey im feature Grammy winning American singer, H.E.R. Dis new single 'No Stress' na love song wey get im get signature Afro beat sounds. Although fans bin dey expect am to drop im album Made in Lagos, di singer release 14s video of di instrumental for social media and tori be say di album go drop for October 15. Di new dey really totori fans for social media. Many of dem dey use di #NoStress to tweet about how dem feel about di song. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54196270 +entertainment Miss World 2021 postponed by organisers sake of Covid-19 "Organisers of di Miss World 2021 don temporarily postpone di global broadcast finale wey suppose hapun for Puerto Rico. Organisers release statement just hours before di pageant suppose start say di events dey postponed due to health and safety interest of contestants, staff, crew and general public sake of Covid-19. Di new date for di finale go dey rescheduled for Puerto Rico Coliseum Jose Miguel Agrelot witin di next 90 days statement from di organisers tok. Inside statement wey di organisers release for dia website, dem say dem make dis decision “afta meeting wit di virologists and medical experts wey dem hire to oversee di Miss World 2021 event plus discussion wit Puerto Rico Health Department.” Dem say despite di additional safety measures wey dem put in place, dem still confam “additional positive cases.” “According to medical experts, di next tin now na immediate quarantine, pending observation and more testing according to best practices for dis kain situations.” Di organisers say na wen health officials and advisors clear di contestants and dia staff wey follow dem come dem go fit return to dia home kontri. Di 70th Miss World beauty pageant bin suppose take place on December 16 for di Coliseo de Puerto Rico José Miguel Agrelot, San Juan, Puerto Rico. Malaysia representatives confam say dia contestant, Lavanya Sivaji, dey among those wey test positive. Inside statement dem post on social media Thursday, di Miss World Malaysia organization say Sivaji dey isolation but dey ""clinically well"" Meanwhile for one Puerto Rico Health Department press conference Thursday, epidemiologist Melissa Marzán tell tori pipo say dem get 38 positive cases wey dey associated with Miss World: 15 staff and 23 contestants. She confam say di pageant organizers, not di island authorities, na im make di decision to postpone." https://www.bbc.com/pidgin/world-59695161 +health Covid-19 stigma: Chinese hotels & apartments don pursue Africans comot from dia property for fear of coronavirus "Hundreds of African residents and businessmen na im dem pursue comot from hotels and apartments for China southern city of Guangzhou as local authorities for di city dey rollout testing campaign for Covid-19, community leaders tell BBC. Di pipo wey dem evict say dem dey discriminate against dem. ""Dem dey accuse us say we get di virus"", Tobenna Victor, wey be Nigerian student for Guangzhou tok. ""We pay rent to them and after dem collect di rent dem chase us comot from di house. Since last night we don dey sleep outside"". ""Dem come our house, tell us say make we for 24 hours for di result but after 24 hours nobody follow us tok, one businessman Lunde Okulunge Isidore, from di Democratic Republic of Congo tok. Some residents still tell BBC say dem no allow dem enta dia apartment, other pipo say dem don force dem to quarantine and dem no show dem dia test result. On Tuesday, Chinese official deny di rumor wey dey fly upandan for internet say na Africans dey spread di virusand di part wia Africans dey live dey on lockdown Guangzhou na home to one of China largest African communities and e don become a hub for African traders wey dey buy and sell goods for di continent. Worry dey increase for China ontop di increase of imported Covid-19 cases, and authorities dey fear say e fit cause another outbreak. Since March, Guangzhou don ask pipo wey come from abroad to quarantine for 14 Days." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52211995 +politics Goodluck Jonathan APC 2023: former president reject All Progressives Party presidential form group buy for am "Nigeria former president Goodluck Jonathan don reject and rubbish di presidential nomination form wey one group bin buy for am. Inside statement wey im Media Adviser Ikechukwu Eze sign, e say, e no dey aware and e no sign am. ""E don come to our notice say one group buy Presidential Nomination and Expression of Interest forms, of di All Progressives Congress APC, in di name of former President Dr. Goodluck Ebele Jonathan. We wish to categorically say Dr. Jonathan no dey aware of dis bid and e no authorize am. We wan state say if di former President wan to contest an election, e go make im intentions clear to di public and no go enta through di back door."" Di statement tok. Di statement also tok say Jonathan never decide weda e go contest or not. ""While we appreciate di ogbonge request by some Nigerians, for Dr. Jonathan to make imself available for di 2023 Presidential election, we wish to state say e never in anyway, commit imself to dis request. To buy a presidential aspiration form in di name Dr. Jonathan without im consent, knowing di position wey e don hold for di kontri dey considered as an insult to im pesin. Di general public dey herefore advised to disregard am."" Di statement add. Although di statement from Jonathan clearly rubbish di tori say dem buy am APC form to contest di upcoming elections for di kontri, e no tok clearly abvout if e join APC or not. Di tori say e port start to spread more on Monday night afta one of President Muhammadu Buhari aide Bashir Ahmad Tweet say Jonathan don port. E never clear which group buy di form yet but di APC presidential nomination and expression of interest forms na N100 million naira. Sometin wey also dey cause tok-tok for di kontri. No be today though dis tori say Jonathan go port or say e don port start. For months now, speculations dey say di former Nigerian president dey plan to defect from di main opposition party, PDP to di governing APC party and den to join di race for di presidency. Inside all dis, Jonathan never ever yet come out publicly to confam or deny say anytin like dat go ever happun or not. Anoda question wey pipo dey ask na weda Jonathan get interest to contest for di 2023 elections. Jonathan never confam dis wan too. Wetin im latest statement tok about am na say: ""While we appreciate di ogbonge request by some Nigerians, for Dr. Jonathan to make imself available for di 2023 Presidential election, we wish to state say e never in anyway, commit imself to dis request."" For April 2022, one group bin storm Jonathan Abuja office to demand say make e declare for di 2023 presidential election. Dem carry placard dey call im name wia dem ask am make e please contest. But Jonathan response to dem den na say make dem ""watch out"". ""Yes, you dey call on me to come and declare for di next election. I no fit tell you say I dey declare. Di political process dey ongoing; just watch out. Di key role you must play na say Nigeria must get somebody wey go carry young people along."" E bin tok. Yes e fit. Di former president serve from 2010 to 2015 as president of Nigeria. According to di constitution. E still fit serve one more term of four years if e decide to run again. As at di time of filing dis report, more dan 15 pipo don come out to declare say dem wan contest di seat of di president under di APC. Dem include di current Vice President Yemi Osinbajo and former govnor of Lagos state Bola Tinubu. Di 2023 presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023 according to di election office INEC. While govnorship and state assembly elections go hold for March 11, 2023. INEC don give all political parties for di kontri deadline of June 2022 to do dia primaries and produce dia candidates wey go fly di party flag for di general election. House of Assembly - N2 million House of Reps - N10 Million Senate - N20 million Governorship - N50 million Presidential - N100 million ""Forms for female aspirants and pipo wey dey live wit disability na free."" APC add. ""Youth wey dey age 25 - 40 years get 50% discount to buy di nomination forms,"" Argungu tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61389824 +entertainment PlayStation 5 price: Nigerians search for wia to buy Sony latest game Game lovers across di world don dey find wia to pre-order di latest Play Station 5 afta Sony release am on 12 November. Sony announce say di video game console go cost $499.99 but di digital model, without disc drive, go also dey available wit starting price of $399.99. Online stores like Target and Best Buy already don place pages wia pesin fit sign up for notifications once di consoles and gear dey available for pre-order. Walmart no even wait for di preorder date of 17 September. Dem Tweet yesterday say make pipo start to dey 'pre-order now.' Sony bin don first sama warning say e fit dey challenging to pre-purchase PS5 sake of high demand and low supply. Walmart GameStop Amazon Target Dis price don put Sony up against Microsoft next-gen consoles wit Xbox Series S wey start at $299 and Xbox Series X for $499 on 10 November. During one livestream showcase wey Sony do for 16 September, dem play different trailers of new games wey dey come to di PS5 wey include: https://www.bbc.com/pidgin/tori-54187852 +entertainment BBNaija: Whitemoney beat Pere, Cross, Emmanuel and Angel to win BBNaija season 6 "Whitemoney don win Big Brother Naija season six. Im beat Liquorose wey reach di last two stage through di way fans vote. Whitemoney wey im real name na Hazel Oyeye Onou score 47% of votes against Liquorose 22.99%. E don be di 6th winner for di ogbonge show and join past winners like: Katung Aduwakwey win first edition for 2006, Efe Ejeba (2017), Miracle Ikechukwu (2018) and Mercy Eke (2019), Laycon 2020. From wildcard to second runner up, Pere journey for Big Brother Naija house don end. Im leave behind Whitemoney and Liquorose as di last man standing. Pere use im eviction interview to declare im love again for Maria, but ""as a friend"". Pere tell Ebuka say im dey go into Nollywood now wey im don comot for di house. Cross also don say bye bye to di Big brother house as di number four man standing afta 10 weeks of intense competition, tasks plus fun. ""I dey too blessed!"" Cross tok as im bin think say im go make am to be top three housemate for di show. Cross tok say wetin dey next for am na to go into entertainment, business and politics. Before Pere and Cross comot, Emmanuel and Angel bin don chop eviction among di top six for di finale of BBNaija. Emmanuel tok afta im eviction say ""im dey surprised to make am dis far for di show."" Im bin no expect am say im go make am till di final. Angel say she feel great say she don finally dey out of di house as she bin don tire - she tok am jokingly. Di second female housemate to reach di final add say she dey excited to be part of di show. Angel dey look forward to start mental health blog afta now. Dis season winner go walk away wit di ogbonge grand prize of N90m. Di N90m grand prize include N30m cash prize, cash in Abeg digital wallet, bitcoins courtesy Patricia, one two-bedroom apartment courtesy RevolutionPlus Property, a top of di range SUV from Nigerian automaker, Innoson Motors and a trip for two wey Travelbeta package." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58781282 +entertainment Tonto Dike and Prince Kpokpogiri: Nollwood star call out ex-lover for alleged 'blackmail' plus how e respond "Nollywood actress Tonto Dike don call out her ex-lover Prince Kpokpogiri again for allegedly blackmailing her. Inside Instagram post to her 6.9 million followers, di popular actress say make prince sop dey run and present imsef to ansa for di allegations against am. ""Afa I listen to these leaked voice note between JOSEPH EGBRI(fake name Prince kpokpogri) and merit, I personally call off my relationship with a man I bin honestly LOVE."" Now dis one no dey enough for blackmail and lies but e dey all good and great. Respectfully, All we dey ask na to come ansa to di law for your illegal recording and release of my private moments (A CRIME) wey happen months back before I actually respectfully end dis relationship, extortion(A CRIME), blackmail(A CRIME) amongst oda tins, allegations about you."" She tok. Di actor end di post by asking her ex-lover to allow di law to operate. ""My darling JOSEPH EGBRI e go dey only fair enough for you to allow di law operate.. If dis na made up allegations you no need to fear, FOR A CLEAN HEART FEAR NOTHING.. But you need to stop running and face di consequences of your actions."" Tonto tok. E no too tey afta Tonto post wey prince respond. According to am, e hands dey clean and e also too bin genuinely love Tonto wen dem dey togeda. ""My awesome T, like I call you Knowing you bin dey pleasurable. E go be a disservice to di institution called love if I say I regret knowing you as no be so. E fit be short memory but e go last a life time. Did I love you? Absolutely yes. For your weaknesses and vulnerability, I still love you and bin ready to walk you through the challenges of life."" Kpokpogiri tok. Although Kpokpogiri no directly tok about di issue of di blackmail of Tonto, e add for im statement for im Instagram page say im hand dey clean and wetin cause dia break-up na anoda mata not di issue of di voice note. ""In our hurts, we do not burn bridges for we go always cross dem again. Na dis rule I dey live by all my life. Countless times, I complain to our mutual friends of how tired I dey of your heavy smoking and drinking. I make am clear say I go to walk away if e continue yet you never stop or make effort despite my willingness to stand by you till you gradually stop. Dis na wetin break us up and no be di voice note. I don live and dey live a clean life. No amount of blackmail fit pull me down."" Prince tok. For July 2021, di actress bin officially confam say she dey in a relationship with Prince Kpokpogri. Di Nollywood actor tag Prince Kpokpogri inside social media post where she dey count her blessings and also refer to am as her 'husband'. She say ""I ADORE YOU @kpokpogri @kingandre_dikeh and all our kids. Thank you to MY HUSBAND."" For di video she post for her verified Instagram handle, e show her and Prince Kpokpogiri for di graduation ceremony of her son, King Andre, di son she get wit her ex-husband Churchill Olakunle. Madam Tonto write say God don answer one of her secret prayers as e give her man wey stand wit her as her head and as a father to her son. She thank God for her new status as she declare say if ""happiness na pesin, e for be her."" Tori of her new found love begin fly wen she celebrate di birthday of di man she claim say she dey in love wit, wit big cake and plenty gifts. Although she no mention name and she bin no post any foto for di post. Plenty pipo bin congratulate her and say dem happy for her. Prince Kpokpogri too enta social media to unveil Tonto Dike and e say she dey blessed among women, im don later delete di post. Prince Kpokpogiri come from Isoko, Delta state. Pipo bin no too know am till e come into limelight recently during im birthday for 27 June 2021 afta tori carry am say na im be di new man wey dey Tonto Dike life." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58635505 +entertainment Asakaa: How drill music find house for Ghana "For inside di middle of global pandemic, na so one ogbonge UK based rapper pack im load enta Ghana say im wan go collabo with 18 year old schoolboy for di remix of song ey dem call Sore. Di track by Yaw Tog and Stormzy don ginger pass six million views for inside YouTube. And na dis track bin ginger di new style of music from Africa. Asaaka or Ghana Drill na di most ogbonge sounds wey dey comot from Africa right now and hopes dey say e fit big like Nigerian Afrobeats and South African amapiano. E sound like combo of di hard baseline of drill music and US rap with di toughness of Ghana Twi language. One of Asakaa biggest supporters be di late Virgil Abloh, wey be Ghanaian fashion designer dem born for Chicago, according to musician, Kwaku DMC. Wen di man wey be Louis Vuitton menswear artistic director and Kanye West associate see di video for im asakaa song for social media, Virgil carry am post for im own Instagram and tag Kwaku DMC. E say, ""I wake up for morning come dey see plenti messages, plenti notification, like wetin dey happun, Dem don hack me? Until I enta my inbox see say, Virgil don tag me."" Kwaku DMC say e follow Abloh wey tell am say im music na ""fire"" and say e go do anytin to help di music and start to dey give dem cloth and show dem. Anoda fast rising rapper Jay Bahd sat asakaa go be one of di biggest types of music to comto Ghana and e don dey show. On music streaming service wey dem dey call Boomplay sat tracks from pipo like Yaw Tog and Jay Bahd dey di list of id top 20 most streamed songs. And di music get famns for obodo oyibo too because according ot Spotify, 46% of di pipo wey dey stream asakaa dey come from UK, US and Germany. And one o di tins wey pipo like about asakaa na di use of language. Even di name of di genre be like di lyrics, na play on words. Di word for ""talk"" for Twi na ""kasa"" and asakaa na wetin dey comot wen you tok kasa backwards. Na DJ and Producer Rabby Jones bin form di word wen e bin drive for midnight with some musicians for Kumasi, Ghana. E say, ""we put drill beat, na im Jay Bahd start to rap. I just shout asakaa and na how we start to run am "" According to artiste, Kofi Jamar na di reversal of words dey all around assakaa as code language so dem go fit jump pass pipo wey no wan hear bad word but fit still reach Kumasi pipo with di real message dem dey tok about. Asakaa na from tougher parts of Kumasi and na way to tok about dia wahala like Yaw Tog sing for Sore about how pipo bin tink say di genre no go make am. Even though for di West dem dey call am Ghana drill na sometin wey young artists and producers for Kumasi no wan hear. Say di sound don grow since 2020 with di way dem dey mix Twi and English for lyrics. Rapper O'Kenneth say to call asakaa, Ghana Drill dey ""boring"". But im admit say most of im fans for social media na from di West as di pipo for Kumasi no too ginge with di sound in di beginning." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60811964 +entertainment Netflix confirm Busi Lurayi death, manager tok how she 'suddenly' die "Busisiwe Lurayi, wey act Tumi for Netflix comedy series How To Ruin Christmas, don die. Her management confam say di South African actress pass away for her residence on Sunday. Netflix South Africa confirm her death on Monday for dia verified Instagram page. Her family don release statement on Busisiwe Lurayi death. For statement wey Lurayi handlers - Eye media Arts - release, dem say: “We dey deeply saddened to notify una of di passing of our beloved Busisiwe Luerayi."" According to her managers , ""she pass away suddenly and dem pronounce her dead for her residency on 10 July 2022.” Di cause of her death still no dey known. Di family say dem go wait for autopsy and ask for privacy during dis 'difficult period'. Meanwhile tributes dey pour in for di South African actress passing. Neflix South Africa dey mourn di passing away of di actress ontop dia social media platform. ""One incredible light don off for South African entertainment industry."" ""We dey deeply saddened by di passing of award-winning stage and screen actor Busi Lurayi. Netflix add. ""We go hold onto di laughs, di beauty and all di moments of joy wey she bring to us. Busi Lurayi na both stage and on-screen actress. Dem sabi her well-well afta she star as Phumzile for one SABC1 sitcom City Ses’la and di spin-off series Ses’Top La. She don since appear for plenty movies and TV series. Her popularity later grow afta she appear for di first two seasons of one Netflix hit series. 'How to Ruin Christmas: The Wedding and How to Ruin Christmas: The Funeral.' Dem born Busi for Tembisa Ekhuruleni for Guatend, South Africa. She don gbab many awards like di Golden Horn Award for Best Supporting Actress for one TV Comedy for 2006. She don also win Golden Horn Award for Best Actress for TV Comedy for 2011." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c3gd0g3v7x2o +health Coronavirus Vaccine: WHO don agree for rules to test African Coronavirus herbal remedies Di World Health Organisation don agree rules for di testing of African herbal remedies to fight Covid- nineteen. WHO regional office for Brazzaville tok say dem don endorse one protocol for clinical trials. Any traditional remedies wey dem judge say e dey safe and effective dem fit begin sharpely-sharpely manufacture am plenti. Di agency tok say sound science na di sole basis for safe and effective traditional therapies. Dem add say di purpose of di new rules na to help and empowering scientists inside Africa to conduct proper clinical trials. Before now, di president of Madagascar, Andry Rajoelina bin dey promote one plant-based drink wey WHO neva test and e dey claim say e fit stop di virus. Di main ingredient for dis Madagascar plant-based drink na, artemisia, wey report say dey effective for di treatment of malaria but no evidence so far if e fit fight Covid-19, according to World Health Organization. WHO announcement dey come as di number of confam cases of coronavirus worldwide don pass 30 million, with reported global deaths standing at more than 957,000. For Africa, dem don record more than 1.3 million cases of di virus and more than 33,000 reported deaths Around 140 potential vaccines for Covid-19 na im dem dey develop around di world, with dozens already wey dem don test on pipo for clinical trials. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54223172 +health Ghana Health Minister test positive for coronavirus – See all we know about am "Health Minister for Ghana, Kwaku Agyeman Manu dey under medical treatment after he test positive for Covid-19. President Akufo-Addo during en address to Ghanaians Sunday evening reveal say de Minister catch de virus in line of duty. ""Make we wish wana hardworking Minister for Health, Hon. Kwaku Agyeman Manu, MP for Dormaa Central, speedy recovery from de virus which he contracted in line of duty,"" President Akufo-Addo add. De Health Minister who dey lead de Covid-19 fight for Ghana be de first high profile government official wey test positive for Covid-19. He currently dey undergo treatment for University of Ghana Medical Centre (UGMC) where he dey in ""stable condition"" according to Ghana Prez. Rumours start dey spread on Saturday say he get de virus no one confirm de claims, until President Akufo-Addo confirm dis during en national address. Mr Agyeman Manu first break news about first cases of Covid-19 for Ghana around March dis year last month talk Ghanaians say make people start dey live plus de virus cos e go dey for a very long time. For like two weeks now de weekly Covid-19 press briefings for Ghana Information Ministry where people like de Health Minister dey attend no dey happen. He also no appear on television for a while until Prez Akufo-Addo confirm de news of en coronavirus status. Meanwhile, another govment functionary, K.K Sam who be Mayor of Secondi-Takoradi die of Covid-19. Meanwhile, President Akufo Addo make de wearing of nose mask for Ghana mandatory as de latest directive. ""Leaving wana homes without face mask or face covering be offence. De Police get instruction to enforce dis directive"" Prez Akufo-Addo add. De Police go enforce dis directive through an Executive Instrument which go make non-compliance to dis an offence punishable by law. Total Covid-19 case count for Ghana be 11,964 out of which some 4,258 recoveries wey 54 people die." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53047537 +health Coronavirus: Cameroon pipo di craiy for strong decision as goment confam five more cases of Covid-19 Cameroon don confirm five more cases for Coronavirus as kontri pipo di beg make goment take strong decision, close border. Dis afternoon health minister, Dr Manaouda Malachie for e normal way don tweet say Cameroon don confirm five new cases for Covid-19. For now e no bi clear who de five pipo bi, wusai deh komot. Wit five more cases de total number now don reach ten. Health official bin tok for national radio dis morning say de first two pipo don well but deh di observe dem. For now only one university close down and prime minister di hold crisis meeting wit goment officials. As de cases di daso increase kontri pipo di beg make goment take strong decision, close border. https://www.bbc.com/pidgin/51792720 +politics Nigeria election 2023: Tinubu, Umahi and Uzor Kalu declare intentions - See steps to become Nigeria president Na season of declaration of political interest for who go be di next Nigeria president as di year 2023 dey knock door. From di national chairman of di ruling All Progressive Congress (APC) party, Ahmed Tinubu, to Ebonyi state govnor, David Umahi and di Chief Whip of di Senate, Orji Uzor Kalu, all of dem don come out to declare interest to become di next presidential candidate to carry APC ticket. So far though, na only interest all of dem don declare, but to become di presidential candidate of any party for Nigeria and finally di president, dis na di steps any interested pesin suppose take. Nigeria dey run democratic system of goment and e get rules and principles for elections. Di 1999 Constitution of di Federal Republic of Nigeria as amended for 2018 give di criteria wey pesin need to become di president. To lead Nigeria you must be: Di first step na to openly declare your interest to your party say you wan be dia candidate for di presidential election. Den you go buy application form for di position you wan contest for. Afta dat di party go do primary elections. Primary elections na internal process wey parties dey take choose dia political candidate for di next general elections. Dis na selection process wey involve all party members, even ordinary ones fit participate for di voting. But dis kain election dey two types, party primary elections fit be direct or indirect primaries. For direct primaries all members, big and small go come out vote for candidate wey dem believe say go win di election. While for indirect primaries, na just few members of di parties dey vote for who go be dia candidate. In recent times enough gbas gbos don happun between di executive arm of goment and di members of Nigeria National Assembly as President Muhammadu Buhari no gree accent to di Electoral Act Amendment Bill wey wan sign direct primaries into law as di rule for all parties to follow. One major factor wey some parties dey consider before dem present candidates for primaries na di issue of zoning. Zoning na very big mata for Nigeria politics. Although e no dey for constitution, big political parties dey use am to determine which part of di kontri president go come from. Zoning na very controversial issue for Nigeria politics. While some politicians dey call for am, odas dey reject am unto say na di best wey to select unfit candidates. E still get di politician wey dey swing both sides, today dem want zoning, tomorrow dem no want, depending on how tins take be on ground. So, for pesin to begin qualify to win party ticket as presidential candidate for im party go also depend on weda di party wan consider zoning. If yes, which zone dem wan shift di presidency go. Wen you finally get your party ticket as dia candidate, you go contest for di election under your party umbrella. To be declared winner and di next president of Nigeria, you must to win 2/3 majority of di vote wey must to spread across all di kontri six geopolitical zones. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59965740 +entertainment Police order singer Portable to report to dia station Police for Ogun state southwest Nigeria don order popular singer Okikiola Habeeb A.K.A. Portable di 'Zazu' coroner to report to dia office or dem go declare am wanted. For statement, police say dem see one trending video wia Portable allegedly oda im boys to beat up one boy and give am injury. Police say such violent act no good and dem no go tolerate am, especially wen e dey come from pesin wey suppose be role model. Portable neva respond to di police invitation as at di time of publishing dis tori and e never tok about am. Di recent video incident no be di only time portable don trend. For anoda video wey trend last week, pipo sight Portable wey e dey do hot argument and almost begin cry. Di short video be like incident wey go lead to fight. Same last week, di Zazu coroner call out Grammy award winner Burna Boy say e dey copy some of im styles. For im Instagram handle, Portable tell Burna say make dem collabo, say e no go good for di Grammy award winner to rip am off. Portable dey notorious for being outspoken and fit dey careless for some of im comments. Some weeks ago, dem nominate Portable for di headies award. As di tori begin fly upandan, di singer release video wia e dey canvass for votes from pipo. Im real name na Habeeb Okikiola, im be rapper, singer and songwriter.\nDi self-proclaimed Son Of Shaku Shaku, don climb di ranks of di kontri fastest-rising singers. Portable Olalomi come from Ogun State, South West of Nigeria.\nFor one video wey im share for im tiktok page, e tok say na Nigeria rap star, Olamide bring am to limelight. Dem bin also share video of wia im meet wit di Nigeria rap star. Portable Omolalomi social media following don increase well-well since e release di new single.\nCurrently, im get plenti followers on Instagram. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4nxr2wxp7qo +health Coronavirus: International Travel latest update from di World Health Organization as EU wan re-open border "Di World Health Organisation don tok say e no dey safe to restart international travel, despite di progress wey don dey with vaccine programmes. WHO chief for Europe, Hans Kluge tok say di situation still dey weak as threat full and uncertainty like new variants of di virus. Based on dis, e add say pipo need to take care and rethink or avoid international travel. Oga Kluge dey tok dis one afta some number of kontris don take di first steps to resume cross-border travel as plan to save dia tourism industry wey di pandemic don affect well-well. ""Di progress dey fragile. We don dey dis situation before. Make we no make di same mistakes wey we make dis time last year, wey lead to di resurgence of Covid-19..."" Hans Kluge tok. ""We don learn our lesson di hard way. We dey di right direction but we need to keep watchful eye on dis virus wey don claim di lives of nearly 1.2 million pipo for dis region."" Yesterday, 19 May, European Union member states recommend say make dem relax coronavirus restrictions on travel into EU for fully-vaccinated pipo and those from kontris wit low infection rates. Di EU ambassadors say dis go allow individual member states to decide on di specific rules and fit still request covid testing. Travellers go then need to dey vaccinated wit injection wey EU and World Health Organisation approve. Di EU go decide di list of kontris wey dem wan permit to come in on Friday, 21 May. Currently only pipo from seven kontries (including Australia, Israel and Singapore,) fit enta EU on holiday, regardless of dia vaccination status. Meanwhile, bars, shops and cultural spaces across France don reopen dia doors as di kontri start to dey lift restrictions. France don also push back dia nationwide curfew from 19:00 to 21:00. Austria don also allow restaurants, cinemas and theatres to open for di first time in six months. Austria goment don also announce say travellers from certain kontris wit low rates of infections no longer need to quarantine from Wednesday, although dem go still need to provide proof of negative test, vaccinations or recent infection." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57191259 +entertainment How dis two Nollywood actors go missing - Latest update "Nollywood actors Cynthia Okereke and Clemson Cornel aka Agbogidi dey miss, Actors Guild of Nigeria [AGN] don announce. AGN dey suspect say na kidnappers gbab dis two popular Nollywood actors wey be dia members. Monalisa Chinda Coker wey be Actors Guild of Nigeria Director of Communications, announce dis news for one statement wey she share for social media and write say; ""Please make we all dey vigilant …di situation dey disturbing...We pray fervently for dia safety and home coming soonest."" According to Monalisa, family members to di two actors report say dem dey miss. Na afta dem no come back from one film location for Ozalla Town, Enugu state for southeast region. AGN wey be di umbrella joinbodi of Nollywood actors, come suspect say e be like say kidnappers don gbab dem, suspicion wey dey under investigation now. Enugu state police command tell BCC Igbo say dem don see di car wey dem believe say belong to actress, Cynthia Okereke. Police tok-tok pesin, say dem received one message about one red car wey dem see for Four-Corners along Enugu- Portharcourt expressway. Daniel Ndukwe say e get di message on Friday, 29 July in the morning and around 11:00am police confam say di car belong to Cynthia Okereke. On Saturday, BBC Pidgin hear from di police official again for latest update. ""Report wey dey available to us na case of missing pesins."" Investigation don start to locate dem and know how dem take disappear, e tok. Di police tok-tok say dem don start investigation concerning di red car wey dem see and di missing pesin. Meanwhile, di news of di suspected kidnap of dis Nollywood actors don increase fear among members of di Actors Guild about dia safety, Monalisa tok. Sake of dis, di president of di AGN, Ejezie Emeka Rollas don order make all all actors avoid going to di outskirt of cities to film. E say except full security cover dey provided to make sure say actor dey safe.\nOga Rollas say e dey shock about wetin happun and tell security agencies to speed up investigations wey go lead to di safe rescue of di actors. Also, reacting to di news, veteran actress, Kate Henshaw, tweet at Nigerian leaders say dis incident of kidnapping gatz to stop; ""Just see one press release Cynthia Okereke and Clemson Cornel, two members of @actorsguildNg dey suspected to be kidnapped. Dem neva return from film location for Ozalla Town, Enugu. President @MBuhari, VP @ProfOsinbajo, Mr Speaker @femigbaja, @PoliceNG. dis gatz to stop!."" Cynthia Okereke na veteran Nollywood actor wey don feature for many films. One popular movie wey she don act inside na Osuofia in London (2003). She also don act for oda movies like , Idemili (2014), Katakata(2021) and odas. For early dis year, one Nigerian pastor, Jeremiah Omoto post for im social media page of how e take surprise Actress Cynthia Okereke and one oda veteran actress, Chinwo Owoh with Car gifts. Clemson Cornel aka Agbogidi na veteran Nollywood Actor wey don also feature for plenti film. For im Instagram handle, Clemson call imsef Nollywood Chief Priest as dis na role wey e dey play well-well for movies. Im last post for instagram na video of behind di scene of one film wey im be native doctor. Some of di film wey e don feature according to IMDB na; Agunnia the Warrior(2021), Idemili, Royal war and odas." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c9958zzpq8xo +business Apple user go pay $11 for Twitter verification Twitter say Apple users go pay eleven dollars monthly for subscription to Twitter Blue from Monday. Di company make di announcement for one tweet on Saturday and say pipo wey subscribe go get edit button, dem go fit upload 1080p videos. Dem say to subscribe to Twitter Blue on web na $8 per month but na $11 per month through Apple iOS. Twitter also tok say subscribers go fit change dia handle, display name or profile foto, but wen dem make di change, dem go lose dia verification temporarily until di social media platform review dia account again. Twitter no explain why dem dey charge Apple users more dan odas on di web but media report bin dey tok say Twitter dey look for ways to offset fees wey Apple dey charge for AppStore. Di company bin launch Twitter Blue for early November before dem pause am sake of say fake accounts kon plenty. Dem kon schedule to launch am on 29 November but dem postpone am again. Elon Musk wey buy Twitter for $44 billion for November express im grievances wit Apple, including di 30% fee di iPhone maker charge software developers for in-app purchase. Im bin accuse Apple of threatening to block Twitter from di AppStore and also tok say di iPhone maker don stop advertising on di social media platform. However, afta meeting wit di Apple chief executive Tim Cook, Musk tweet say di misunderstanding about Twitter and Apple don dey resolved. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0jg2z80exgo +entertainment Paing Takhon: Myanmar celebrity model dem arrest ontop di kontri coup protest crackdown spark reactions "Military don arrest one of Myanmar most popular celebrities as part of dia crackdown on artists and actors. Paing Takhon, na model and actor with millions of fans for Myanmar and Thailand, e bin active for both online protests and in-person rallies. Dem don also take down Takhon Instagram - with more dan a million followers - as well as im Facebook account. Di military seize power inside coup on 1 February, dis one spark weeks of protests. Around 600 civilians don die as forces respond to di demonstrations with violence. According to one Facebook post by Takhon sister Thi Thi Lwin, around 50 soldiers with eight military trucks come to arrest am at around 05:00 local time (22:30 GMT Wednesday) on Thursday. One of im close pesin wey no want make we call im name, tell BBC say, dem carry am from im mother house for North Dagon, one township for Yangon. Dem say e bin dey suffer from ""serious depression"". Di friend add say Takhon bin dey suffer from a physical condition, e add say e no even fit ""stand or walk properly"", although e no give any further details. But dem tok say e bin dey ""aware of di consequences"" wey dey await am, dem add say e ""no dey scared at all"". Both dem collect im mobile phones along with am, dem tok. Di 24-year-old bin participate for several demonstrations and marches. E bin also post images of di ousted civilian leader and pro-democracy icon Aung San Suu Kyi. ""We strongly condemn military coup. We demand immediate release of state counseller [sic] Daw Aung San Suu Kyi, President U Win Myint, civilian government ministers and elected members of perliment [sic],"" Mr Takhon bin write for one online post wey dem don also take down. ""We demand to respect 2020 election results and form new civillian [sic] government soonest by NLD led perliment [sic]."" Im detention na di latest on di crackdown on celebrities in recent days. E dey come a day afta Myanmar ambassador to London say military attaché don take over di embassy and force im out. Dis wan too happun afta Kyaw Zwar Minn, wey dem don now remove from im position, say make dem release Aung San Suu Kyi. Dem don issue arrest warrants for around 100 filmmakers, actors, celebrities and journalists say dem speak out against di coup. Earlier dis week, security forces arrest di kontri best-known comedian Zarganar. Last week, Myanmar beauty pageant winner Han Lay, speak out against di coup for one event wey happun for Thailand. Mass protests don dey happun across Myanmar, wey also dey known as Burma, since di military seiz control on 1 February and declare one year state of emergency. Di armed forces claim say widespread fraud happun during di general election late last year wey return elected leader Aung San Suu Kyi and her National League for Democracy party (NLD) to power." https://www.bbc.com/pidgin/world-56672601 +health Coronavirus - Virus: Ghana students for Wuhan say den receive $500 each from govment for upkeep "Ghana students for Wuhan say dem receive $500 from govment which dem for take buy some supplies wey dem dey need during the lockdown. Students say dem no receive any food supplies yet but confirm say dem get some monies. Some students for Wuhan confirm give BBC Pidgin say dem receive $500 each from govment for dema upkeep. Despite de funds wey dem send, govment say evacuation of student no be possible. ""We totally, government totally, Mr President totally understand de situation dem dey inside but as at last week Wednesday, we feel say evacuation no be possible at dis point,"" Foreign Affairs Minister, Shirley Ayorkor Botchway talk. Meanwhile, de Ghana Health Service (GHS) set up hot lines for public where dem fit call for assistance on any coronavirus issues. De two hotline go dey Greater Accra Regional Hospital where health experts go dey on standby plus information den any assistance in relation to de deadly virus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51574655 +entertainment Meet di cute family wey dey heat up social media with dia dance steps """Family wey dey dance together dey stay together"" dis na wetin Sara Karrit wey love to dey dance with her husband and son tok as dem continue to dey entertain millions of pipo before and during di coronavirus pandemic. Sara wey dey always post di dance videos wey she do with her family for social media say dancing don become major part of dia life. Truly dancing don really play big role for di life of dis family as di couple meet demsef during one of Sara dance class. Di husband wey be software engineer, Akif el Sabeh tok say; ""Dancing dey our blood, every time dance, morning, evening, night, sleep, na dance."" And di son Steve say he wan be like di father. Producer: Princess Igho Williams Video: Sarah Tamiyu" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54261809 +entertainment Big Brother Naija Season 5 Nengi, Dorathy, Wathony, Laycon, Head of House and highlights of Day 1 for BBNaija 2020 housemates on Lockdown Some of di major highlights for di Big Brother Naija season 5 Day one Di excitement don begin for Big Brother Naija season 5 as Day 1 don come and go. Dis na some of di main- di main tins wey happun on di first day of di 2020 season. Afta enough completion for who go become head of house, di first head of house don show for di 2020 BBNaija competition. Di first head of House and deputy head of House for di 2020 show na two women Rebecca Nengi Hampson and Florence Wathoni Ayansi. Di Head of House, Nengi dey 22 years. Her age no go down well wit some pipo wey feel say she too young to lead di Big Brother House. Some housemates don begin pick dia love and pipo wey dem go do alliance or collabo wit for di house. E be like BBNaija don dey get im own entangelement! Erica dey try connect wit Ozo but e be like say Ozo get eye for, and dey try im luck wit Nengi. Lilo and Eric dey gum demsef dey go already. Dis na love dey for air so? https://www.bbc.com/pidgin/tori-53484789 +sports Serena Williams: Simona Halep win her first Wimbledon title in less dan one hour "Simona Halep beat Serena Williams to win her first Wimbledon title for di 2019 women's finals on Saturday. Halep wey be former world number one play perfect game to beat Serena for straight set victory 6-2 6-2 for match wey last just 56 minutes. Williams wey bin lose last year final to Angelique Kerber bin dey hope to win dis year Wimbledon title so dat she go equal Australia Margaret Court record of twenty-four Grand Slam singles title but e no work out for her. Halep say ""dis na di best match I don ever play,"" na wetin she tok ""Fear catch me small. My belle bin pain me before."" Dis na di third time wey 37-year-old Williams go lose finals inside 12 months, ""She play very well today e be dey like say e go be happun for me,"" na wetin Williams tok. For di seventh year now for di women's single final for Wimbledon all di victory dem end for straight set. Wimbledon increase dia prize money for dis year tournament to £38 million. Di men and women singles winners go pocket £2.35m each while dey runner up go collect £1.175 million" https://www.bbc.com/pidgin/sport-48975943 +sports Lamine Diack IAAF: Former Head of world athletics wey chop sentence last year don die at di age of 88, "Di former president of World Athletics (fomerly International Association of Athletics Federations, IAAF), Lamine Diack don die at di age of 88. Diack wey bin chop conviction last year sake of corruption die for im house for Senegal on Friday. Diack son announce di death of im papa to Reuters. According Diack son, Papa Massata Diack, im papa ""die at home of a natural death"". Dem go hold Diack burial later on Friday. Wen dem convict Diack for corruption, im lawyers bin say he get poor health, say he go die if dem send am go prison. Dem put am for house arrest and release am on bail dis year. Na di owner of Jaraaf, Cheikh Seck pay 500,000 euro ($565,000 or £425,000) bond wey dem take release am. Di owner of di football club wey dey Senegal say Diack na good man and great leader. ""Im be good man and great leader. We bin wan make he come back home. Na one month e take us (to gather di 500,000 euros),"" Seck tok after Diack die. For September 2020, court find Diack guilty say he bin collect bribes from Russian athletes wey dem suspect of using drugs sake of say he won cover up dia test results. French Court also find Diack guilty say e collect Russian money to finance di 2012 presidential campaign of Macky Sall for Senegal. Court say Diack enter dis mago-mago sake of say he won slow down anti-doping procedures. Diack bin also ask for bribe wey reach €3.45m from athletes wey dem suspect of using drugs. Court say Diak give officials of IAAF money to cover up for di athletes. Di court give Diack four years prison sentence but two years bin dey suspended." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59516464 +entertainment Omah Lay: Uganda musician Cindy Sanyu profile, Omah Lay and Tems lessons for Nigeria "One video wey show Cindy Sanyu one Ugandan musician, dey criticize Nigerian music stars, Omah Lay and Tems,onto say dem do show for her kontri during lockdown make many pipo vex. For di video wey don go viral for social media Sanyu, say ""a foreigner do concert for dis kontri wit no social distancing, no masks and dis idiots even post am online and dey proud say im concert dey successful for Uganda"", na wetin she tok. Many pipo blast her for di kain words she use inside di video and some even accuse her of jealousy. Uganda Police bin charge Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openyi alias Tems, plus one oda Nigerian Muyiwa Awoniyi wit offence of ""negligently doing acts wey fit spread infectious diseases"". Dem later drop di charges and release di singers on Tuesday wen dey bin arrest since Sunday December 13. Cinderella Sanyu aka Cindy Sanyu the Kingherself, na female afro-pop singer and songwriter.wey dey based for Kampala Uganda. Some of her hit song na nawewe and outta my mind wey do well for charts but di song wey make her blow na You and me wey she feature Ogbonge Nigerian artist P-square. Sanyu attend Ngora high school and tori be say she dey engaged since February 2, 2020. Uganda Covid-19 rules As part of dia effort to control di spread of Covid-19 pandemic for dia kontri di ministry of health release guidelines and suspend concert. Dat guideline still stand up till now. Nigeria celebs show full support for Omah Lay and Tems Nigerian artistes and entertainers raise dia voice in support of dia colleague Omah Lay, wen authorities hand cuff and remand dem for prison ontop accuse say dem break dia Covid-19 rules for Uganda. Nigeria goment sharp-sharp response Nigeria Mission for Uganda dey do everything possible to free musicians Omah lay and Tems. Minister of Foreign Affairs Geoffrey Onyeama tweet say dem dey engage wit authorities for Uganda at di highest level. Uganda goment apologise Nigeria minister of foreign affairs Geoffrey Onyeama reveal say im Uganda counterpart Sam Kutesa get back to am to apologise on behalf of di goment." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55329722 +sports In pictures: Queen sporting memories BBC Sport share photos of di Queen life in sport. https://www.bbc.com/pidgin/tori-62849336 +sports Zayn Ali Salman, di four year old youngest ever footballer Arsenal just sign "Zayn Ali Salman na just four years old wen e catch di attention of one of di biggest football clubs for London, Arsenal FC. E go be di youngest pesin ever to train for di Arsenal pre-academy. One Arsenal Talent scout na im discover Zayn Salman as dem see am dey play wit pipo wey be twice im age and dey play very well. Oga of di Talent scout, Stephen Deans, say Zayn too sharp for im age wit di things wey e dey do. Im coach Austin Schofield tell BBC say dem put am wit children wey senior am for age, still e play pass dem. ""We put am wit im age range wey be 5, 6, 7 and e dey quick pass dem, e dey more willing to get di ball, di way e kick di ball, pass di ball, strike di ball, beta pass di oda children won."" E tok. Zayn papa say na di day dem born am dem sabi say e dey different because e carry im head up and begin look around, something wey normal children no fit do. E add join say Zayn dey strong and e get unbelievable balance from im young age. Di youngest arsenal player say im dey always play wit children wey be seven and eight and e dey make am feel bad. Zayn add join say im best team na Arsenal." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59003847 +entertainment Big Brother Naija Season 5 housemates biography: What you need to know about di 2020 contestants wey just enta di 'lockdown' house "Big Brother Naija season 5 wey pipo don dey wait for since don begin today as di 20 housemates wey go stay inside di 'lockdown' house for 10 weeks enta di crib afta 14 days quarantine wey dem bin dey sake of di coronavirus pandemic. Ozoemena wey be 27 years old na Consultant and entrepreneur from Imo State. One of im greatest achievements na to work with di UEFA Federation for Europe. E study Economics and like to dey play loud music in di morning and to dey bang on doors. Victoria Adeyele wey be 23 years old na musician wey base for Lagos, Nigeria. Dem born and raise her for London and she move come Lagos almost one year ago to begin her music career. She say her parents na Nigerians and say she dey enjoy acting, socializing and making pipo laugh. Vee say she no eva don dey relationship wey last longer than six month. Nelson Enwerem Prince wey be 24 years old na entrepreneur from Abia. E don do modelling, fashion designing plus interior decoration and na graduate of pure physics from the University of Calabar. Prince say im like to dey ignore pipo knowingly and like working out, swimming, food and reading about ancient religions and African history. Boluwatife Aderogba na 23 years old dietician from Lagos, Nigeria. She be also entrepreneur and describe hersef as ""a product of God's grace"". Lilo say her biggest achievement na starting her own brand. Timmy Sinclair na 35-year-old creative artist from Bayelsa State, Nigeria. E consider himsef as a storyteller wey dey uses di mediums of film, and music to express himsef. Tricky Tee say im na pesin wey no fit into society and e dey too kpako to be butty plus im like food. Among di new housemates na; Dietician, singer Uber Driver and odas. Lucy Essien na 30-year-old entrepreneur from Cross River. She say she be simple girl not so average and can dey mean and rude if pesin step on her toes. Lucy say she believe in fairy tales, like good food and like her space. Terseer Kiddwaya na 27 years old self-employed man wey come from Benue State. E describe himsef as confident, good looking, ambitious and pesin wey dey highly motivated. E say im also dey confident and arrogant all at di same time and love travelling. Dorathy Bachor na 24-year-old entrepreneur from Delta State and she believe she be di only one wey fit make you smile. She say her biggest achievement na SHOPFORME - dat na di biggest procurement company inside Nigeria. Praise Nelson na 28-year-old dancer from Enugu and e no dey new to fame or competing. E be di winner for di K-Pop World Festival, South Korea 2015 and win third place for di national Dance Competition for 2010. E be also fitness and personal trainer and certified Latin ballroom expert. Praise say im like meeting new pipo and im na life of di party. Florence Wathoni Anyansi na 29-year-old fashion entrepreneur and she be single mother wey dey do her fashion business and parenting blog at di same time She say she fit speak and write Swahili wella as her mama na from Kenya and her Papa na Igbo. Tochukwu Okechukwu na 28-year-old rapper and real estate agent from Imo state. E say e dey live and breathe entertainment and of Education chemistry E say im dey straight forward and na social pesin. Im biggest achievement na to dey independent and to get education. Kate Jones na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria. She describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life. She say she want to dey famous, she like money wel-well and hate poverty. Her dream na to get di biggest luxury fashion brand for di world. Eric Akhigbe na 24 years old final year student for University of Lagos and come from Edo State. E say im na pipo pesin and dey get pleasure if e complete any task E describe himsef as fun, e like competitive sports and like fitness well-well plus also enjoy winning. Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London. She say she dey passionate to be big time celebrity and like to get drunk and dance in front of di mirror alone. Ezekiel Bright Osemudiame na 29-year-old sailor from Edo State. Brighto say e be di youngest of six kids and get degree in Marine Engineering from Arab Academy for Science Technology and Maritime Transport inside Alexandria, Egypt with plenti oda professional certifications. Im biggest achievement na scholarship wey im get to study abroad plus also im third engineer license including oda professional certificates. E say e no like to dey offend pipo and e can speak Ibo, Hausa, Yoruba, Edo plus little bit of Arabic. e like to dey swim, travel and like adventure. Aisha Umaru na 25-year-old entrepreneur from Sokoto state. She consider hersef great team player wey dey get along with pipo. She rely on healthy diet. She say she can be dramatic sometimes but very emotional. She like singing, going out and having having fun. Emuobonuvie Akpofure na 26 year old ride-hailing app driver from Delta State . E describe imsef as fun, tolerant, loving and smart. E also dey secretive. E biggest achievement na wen im win N 500 000 from one talent competition. E say e like wen pipo dey underestimate am and call imsef problem. Tolani Shobajo na 27-year-old media personality from Lagos state. Tolani na energetic gingered babe. Pipo always call her di life of di party. Tolanibaj say she come di house for di money, she like money and she like Naira Marley. Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos. E be graduate of philosophy from University of Lagos. E say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata. E biggest achievement na im song 'Fierce' wey dey for MTV BASE Top ten charts for six months. Rebecca Hampson na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures. She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53464874 +entertainment Big Brother Naija housemates biography: Wathon and Ka3na fight - Kate Jones AKA Ka3na and Florence Wathoni Anyansi na first two fighting among BBNaija 'Lockdown' Season 5 "Wetin suppose be one fun Trivia turn sour on Friday night for Big Brother Naija live television reality show. Two housemates inside Biggie house, Wathoni, and Katrina AKA Ka3na fight over a disagreement to become di first two fighting in BBNaija House 2020. Inside di video, Ka3na dey tell Wathoni say she no get right to call her name like dat. She add say ""if you call my name, I will finish you. If you get issues wit me, face me and tell me"". According to Ka3na, she don show everione inside di house her real character and she no be fake girl so if Wathoni or any oda pesin no fit stand her, make dem no come close to her. Deputy Head of House: Wathoni, na 29-year-old fashion entrepreneur. Florence Wathoni Anyansi na 29-year-old fashion entrepreneur and she be single mother wey dey do her fashion business and parenting blog at di same time She say she fit speak and write Swahili wella as her mama na from Kenya and her Papa na Igbo. Kate Jones na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria. She describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life. She say she want to dey famous, she like money wel-well and hate poverty. Her dream na to get di biggest luxury fashion brand for di world." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53535064 +politics Chukwuka Monye and Khadijah Okunnu-Lamidi biography - Nigeria 2023 general elections "Chukwuka Monye and Khadijah Okunnu-Lamidi recently declare dia intention to contest Nigeria 2023 presidential election. But who dem be? Di two young Nigerians latest declaration signal di possibility say more young pipo fit put serious interest for di next general election. Na shortly before di 2019 Nigeria election na im civil society groups begin launch campaigns on not too young to run. In fact, na for May 2018 President Muhammadu Buhari sign di not too young to run as a law wey reduce di age of running for elective positions. For dis law, dem reduce di age to run for Nigeria President office from 40 to 30 and independent candidature in Nigeria. So wetin 42-year-old Monye and 38-year-old Okunnu-Lamidi do don stir huge public interest on top who fit succeed Buhari by 2023. But who be Chukwuka Monye and Khadijah Okunnu-Lamidi? BBC Pidgin don look up biography to share wit you - just read on. Monye wey declare im intention on Saturday, January 15, 2022 promise to close di gap ""between generations, public and private sectors. E also promise Nigerians say im go close di gap between di north and di south and between Nigeria and di international community"". Chukwuka Monye say im dey ""for unique position sake of im age and experience to serve di bridge builder."" Khadijah Okunnu-Lamidi, na di first woman to declare her intention to be president come 2023 . Mrs Okunnu-Lamidi say she go rekindle hope and make Nigeria work for Nigerians if she become president. Although Monye and Okunnu-Lamidi don declare dia intention to become president, dem neva tok under which party each of dem go contest. Chukwuka Monye come from Onicha-Ugbo, for Aniocha north local goment area of Delta state south south Nigeria. Im do im University degree for Warner University, Florida, USA, wia im become di first to finish im four years programme inside three years. Afta dat im stay, work for Florida for some years before im return to Nigeria. Chukuwaka Monye dey 42 years and get only Nigeria passport Im na University of Oxford trained innovation strategist wey dedicate im career to building business and mentoring leaders. Since di past 18 years, im na co-founder and director of Ciuci Consulting wey be multinational consulting company. E also serve as Director General of di Delta Economic Summit Forum for six years from June 2015 to May 2021. Money na Wall Street Journal, Amazon and USA Today bestselling author for im contribution to di book, Business Success Secrets: Entrepreneurial Thinking dat works. Money company Ciuci receive award for di Best Business Operations Management Consultancy - Africa Awards 2020, wey Corporate Vision UK give. Okkun-Lamidi na from Lagos. Dem born her im rich family wey don dey serve di public for years. Di 38 year old na journalist and only pikin wey her papa and mama born togeda. Her papa Lateef Olufemi Okuunu, na senior advocate of Nigeria and former pro-chancellor and chairman of di governing council of University of Agriculture, Makurdi, Benue state. She get degree for Business Administration from di University of Bolton RAK campus for United Arab Emirate (UAE). Her master degree na for Strategic Project Management from Heriot-Watt University, Dubai, UAE. Khadijah na di founder and CEO of Slice Media Solutions, wey be advertising agency. She get serious passion for gender balance and youth advocacy." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60013989 +politics Edo Governorship Election 2020: Why Edo never get female governor? "For di Edo Governorship election wey go hold on 19 September, 2020, only two women among di 14 candidates dey contest for di Governorship position and two women dey contest for deputy governor. Di two female governorship candidates na Mabel Oboh of African Democratic Congress (ADC), and Agol Tracy of New Nigeria Peoples Party (NNPP); while di two female deputy governorship candidates na Mogbelehan Pauline of Labour Party (LP) and Omion Omonye of Social Democratic Party (SDP). Dis na improvement from di last governorship election for 2016 wia only one woman, Tracy Agol contest di Governorship position under di Peoples Party of Nigeria PPN. Tracy Ebun Agol wey dey contest for di Edo Governorship election for di second time tell BBC Pidgin say di participation of women in politics for Edo State still dey very-very low and e get why. ""Fear of victimisation, fear of oppression and family fears naim keep dem away from politics. But di few of us wey don enta di political arena, we dey hold our head high and we refuse to be oppressed, we refuse to be intimidated and we refuse to be harassed."" Di NNPP candidate say men don dominate di political scene for too long and di women no dey help matters because even wen dem go to canvass for votes from fellow women, dem no dey take am serious. ""Di first tin na for dem to come out to vote. Dem get dia voters card and dat one don give dem power to change di situation and comot Edo State from di cabal wey don oppress dem for so long and put a capable woman wey go change tins."" Mabel Oboh wey dey contest for govnor under Africa Democratic Congress ADC add say di reason why Edo never get female govnor dey similar to di reason why Nigeria never get female president: women no dey gree come out to contest. Mabel Oboh say if women get for mind say as dem dey come contest dem go face challenges but dem still get di determination to go through, dem go succeed. Oboh also call on political parties to encourage women to step forward to contest and also support dem to win. If di political parties get structures wey go encourage and push womento contest and support dem to win, many of dem wey get di capacity and intelligence go come forward and make impact. ""Di way we dey do politics too gatz change. Politics need plenty money but wetin dem dey use di money do, no be to buy votes? If pipo realise say dat money dem collect dem dey sell dia future and right to good governance, tins go change. So we also need to change our orientation of wetin politics suppose be and support pipo wey get vision and capacity to serve cos politics na call to serve pipo not di oda way round."" Goldfish Rahmatulai wey be lawyer and politician add say na big very challenge for women in politics for Edo State as di first time a woman try come out to contest na 2007 but she no win di party nomination, na aspiration e end. Dat same year, three women enter di House of Assembly and one become di Speaker but she only last for three months before dem ask her to step down to become di deputy speaker. ""Women na di ones wey get voice. Na dem be active mobilizers and campaigners but na dia e end. Dem dey always sideline dem for di roundtable wen di main political negotiations dey go on. Wetin make political meeting dey always hold for night? Once woman comot and stay out late sake of political waka, pipo go begin advice di husband say she dey neglect di home, some go call her names say she dey wayward, dey follow man and sleep wit dem to get political position and wen dem try come out, many times dem dey induce dem to drop dia ambition. But tins don dey change. Women don dey speak out."" Austin Osakue, di Executive Director for Good Governance and Social Change for Benin City say di fact say only two women dey come out for govnor and two for deputy governor for di election show say women never start to take active politics seriously and di earlier pipo see am as challenge for evribodi, not just for women, na den tins fit begin change. ""Make we no see am as struggle for only women alone. E no dey proper say 50% of di population wey suppose contribute for active politics dey relegated. Women need to come out come contest. Women need to empower demsef and support oda women wey dey also contest"". Osakue tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53928742 +health Is Covid-19 airborne? Air conditioning and coronavirus plus wetin WHO tok and why e dey important "Until recently, di World Health Organization (WHO) don consider say contact wit surfaces wey dey infected wit coronavirus na di only way to catch di disease, since na wetin dia research show be dis. Dis na when Covid-19 follow small-small drops wey comot from pesin mouth when dem cough or sneeze. Dis na di reason why WHO officials torchlight handwashing as di main way to prevent Covid-19. But now, dem say dem realise say 'airborne transmission' na something wey fit happun. Dis one mean say coronavirus fit spread through small particles wey dey comot from pesin mouth. If dem confam di evidence, dis go affect how pipo package demsef to avoid infection inside place like house, building etc. Airborne transmission dey happen wen pesin draw air wey get particles of virus or bacteria carried inside nose or mouth. Dis particles go don hang for air tey and because dem small well-well, e fit spread. Example of airborne diseases na tuberculosis, flu and pneumonia. Studies don show say coronavirus wey dem spray for air fit dey alive for at least three hours. But scientists say dis experiment na for inside laboratory, and e dey different from real life. In di US city of Mount Vernon for Washington, dem suspect say just one infect at least 45 others, from just singing wey dem do todega as choir members. Some of those wey catch bin no break any social distancing rules. Di way disease dey spread na im dey determine di method to take stop am. Currently, WHO advice for Covid-19 na to wash hands with warm water and soap for 20 seconds, and do social distancing. But some scientists now dey even though dis method dey good, e no go reach to stop airborne transmission. So far di WHO never tok anything join dia current advice but dem dey torchlight di evidence. If dem confam am, official advice fit change to ask compulsory face mask, especially for bars, restaurants and public transport. Even places wey dey get air conditioner fit follow. Recently 239 scientists from 32 kontris publish open letter to WHO so as for dem to torchlight airborne transmission wey dem say dey possible. ""Dis no be attack on WHO. Nascientific debate, but we feel say we need to go public because dem no gree hear di evidence afta plenty tok wit dem,"" tok Jose Jimenez, sabi pesin for University of Colorado wey follow sign di paper. WHO adviser, Dr. David Heymann, react say dem dey expect solid results from more research before dem torchlight new strategy to counter di virus." https://www.bbc.com/pidgin/world-53394951 +sports Coronavirus: CAF fit cancel CHAN 2020 for Cameroon "Confederation of African Football, CAF don say deh di watch Cameroon as host for African Football Championship, CHAN as coronavirus don enta big African football kontris. Cameroon go host CHAN 2020 from 4-25 April and na one of de kontris for announce say two pipo don test positive for coronavirus recently. CAF komot release on coronavirus say dia team of doctors di check de situation for continent. Eight major football kontris for Africa don already get de virus: Egypt, Algeria, Tunisia, Morocco, Nigeria, Senegal, Cameroon and South Africa. ""We no di too worry about de situation but we bi on alert for future matches like CAF Champions League, CAF Confederations Cup and African Nations Championship, CHAN weh e suppose take place for Cameroon. Cameroon also apply for host CAF Champions League. Just now CAF medical teams di watch, di report for executive committee and if de situation wowo, CAF for decide make de play matches wit no fans, postpone or cancel. For now CAF di promote WHO guideline for keep safe from de virus." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51781066 +sports Argentina beat France on penalty to become 2022 Fifa World Cup champions "Lionel Messi don lead Argentina to World Cup glory after dem beat France on penalties for one of di most thrilling climax for di tournament history. E first be like say Argentina bin throway di trophy , afta Kylian Mbappe score twice for di last 10 minutes to take di tie into extra time, afta one Messi penalty and a sweeping finish from Angel di Maria don see di Argentines 2-0 up for di first half. Messi restore dia lead for di extra period, before Mbappe shock di South Americans again from di penalty spot to force one shootout wit im third - di first hat-trick for anyWorld Cup final since 1966. But Kingsley Coman get im penalty saved by Argentina goalkeeper Emiliano Martinez, and Aurelien Tchouameni tlater miss di target, as im allow Gonzalo Montiel fire home di winner and cause ogbonge incredible scenes. Argentina lineup (4-4-2, right to left): 23. E. Martinez (GK) — 26. Molina, 13. Romero, 19. Otamendi, 3. Tagliafico — 11. Di Maria, 7. De Paul, 24. Fernandez, 20. Mac Allister  — 10. Messi, 9. Alvarez France lineup (4-2-3-1, right to left): 1. Lloris (GK) — 5. Kounde, 4. Varane, 18. Upamecano, 22. T. Hernandez — 8. Tchouameni, 14. Rabiot — 11. Dembele, 7. Griezmann, 10. Mbappe. — 14.Rabiot. Szymon Marciniak supervise di game. France dey kick-off. Match don start enjoy di game! 1 mins: Adrien Rabiot (France) commit one rough challenge and Szymon Marciniak blow im whistle for a foul. 2 mins: Rodrigo de Paul (Argentina) commit one ugly tackle on im opponent, but e no get caution from di referee. Free kick. France go probably just try to cross di ball in from here. 3 mins: Angel Di Maria (Argentina) cross into di box from near di side line, but im no connect as im want and di well-organized defence clear am off. 4 mins: Dayot Upamecano (France) make a rough challenge and Szymon Marciniak blow im whistle for a foul. 5 mins: Angel Di Maria (Argentina) go on one solo run, but im fails to create a chance as an opposition player block am. 5 mins: Alexis Mac Allister (Argentina) latch on to one accurate pass on di edge of di box and unleash one strong shot towards goal, but di goal keeper deny am. 7 mins:Julian Alvarez (Argentina) jump into one tackle and Szymon Marciniak signal say na foul. 8 mins: Rodrigo de Paul (Argentina) meet one cross just outside di area and get in one strike from a promising position, but defender block di ball. 9 mins: Opposition defence clear off one resulting corner from Lionel Messi (Argentina) 11 mins: Hugo Lloris (France) be like dem don pick up a minor injury, but e look like im go fit continue to dey play. 15 mins: Lionel Messi (Argentina) send one quick through ball into space for im teammate wey dey close to di offside line, but one of di defenders stop and and clear di danger. 16 mins: Di ball possession at di moment na 55:45. 19 mins: 'Antoine Griezmann (France) take free kick. 20 mins: Antoine Griezmann find di head of Olivier Giroud (France) wit one clever free kick, and im crashes in one powerful close-range header at goal wey just just fly ova di bar. Unlucky! 23 mins: Goal! Lionel Messi (Argentina) coolly convert di penalty kick! Argentina 1-0 France 29 mins: Lionel Messi (Argentina) race towards goal but di defender get back well to make a challenge. Dem award Argentina one corner kick. 31 mins: 'Angel Di Maria (Argentina) dey unable to feed oneaccurate cross into di box. Di ball dey out of play. France go get a throw-in. 33 mins: Alexis Mac Allister (Argentina) receive one deflected pass on di edge of di box and smash di ball at goal. Unfortunately for am, e dey well wide of di right post. 36 mins: Goal! Angel Di Maria (Argentina)! Argentina 2-0 France Alexis Mac Allister find himself wit di ball at im feet for space afta one lightning counter attack. Im look and up slides di ball to Angel Di Maria (Argentina), wey coolly slots di ball past di keeper from close in. make am 2:0. 42 mins: Szymon Marciniak blow im whistle afta Randal Kolo Muani (France) bring one of im opponents down wit one strong tackle. 45 mins: Julian Alvarez (Argentina) commit one ugly challenge. Di referee see am and immediately blow im whistle. Dem go play additional 7 min. for di first half. 45+2 mins: E be like Theo Hernandez (France) see red wit dat tackle. Szymon Marciniak no go tolerate dat kain behaviour on di pitch and blows for a foul. 45+3 mins: Di current number of shots on target for both teams na 6:0. 45+5 mins: France be like dem dey find dia feet as dem enjoy some possession. Great movement by di offensive players wey allow di defenders to set up di attack. 45+7 mins: Enzo Fernandez (Argentina) dey penalised. 45+7 mins: Enzo Fernandez (Argentina) dey booked afta e bring down an opponent. Szymon Marciniak get easy-decision to make. First half don end Second half don start 46 mins: Enzo Fernandez (Argentina) attempt to pick out one free teammate inside di box, but Hugo Lloris come off si line to clear di ball away. 48 mins: One crossfield pass from Raphael Varane (France) lack accuracy and di opposition gain possession. 50 mins: Rodrigo de Paul (Argentina) get on di end of one cross inside di box and sweep di ball goalwards towards di middle of di goal, but Hugo Lloris dey well positioned and im easily deal wit di effort. 51 mins: Kylian Mbappe (France) receive one clever through ball wey fit put am in one promising position, but di defence dey alert to di danger. Now France get corner kick. 53 mins: Lionel Messi (Argentina) put one dangerous cross into di box, but di first man clear am off. 55 mins: Adrien Rabiot (France) rgbab one yellow card for tackle wey no follow. 57 mins: Rodrigo de Paul (Argentina) dey move okay again afta one injury scare. 57 mins: Randal Kolo Muani (France) look to break free, but one opposing player clear di ball away. Di referee and di linesman both signal one throw-in for France. 58 mins: Kylian Mbappe (France) tackle one bit over-zealously and Szymon Marciniak blow for foul. 59 mins: Hugo Lloris pull off one great save to deny Julian Alvarez (Argentina), wey make imsef some space inside di box and unleash one quick low drive to di bottom left corner. 60 mins: CHANCE! Angel Di Maria find Lionel Messi (Argentina) wit one sweet pass, but im no find di target as im effort from inside di box go just wide of di right post! 62 mins: Di shots on goal statistics – 5:0. 62 mins: Theo Hernandez (France) flight for di cross, but di defender dey alert and clear to safety. 63 mins: Julian Alvarez (Argentina) throw one pass through di eye of a needle into di box for Alexis Mac Allister, but Hugo Lloris display great awareness to stop am. 64 mins: Substitution. Marcos Acuna (Argentina). dey replace Angel Di Maria. 67 mins: Antoine Griezmann (France) gbab one neat ball into di box in the direction of Randal Kolo Muani, but im no fit get on di end of di pass. 68 mins: 'Randal Kolo Muani (France) leap to meet di corner, but fire im header back across goal from close in and e go well wide of di left post. 69 mins: Enzo Fernandez (Argentina) clearly handle di ball, but im dey surprise wen di referee blow im whistle. 71 mins: Kylian Mbappe (France) show off im skills wit one mazy run to di edge of di box and then fire in one disappointing shot wey fly high ova di bar. 72 mins: Enzo Fernandez (Argentina) collect one low pass just outside di box and unleash one ogbonge strike towards di middle of di goal. Hugo Lloris pull off one reflexive save to block im effort. Correct goalkeeping skill! 71 mins: Time for substitution. Kingsley Coman (France) dey on for Antoine Griezmann. 74 mins: Aurelien Tchouameni (France) rob one opponent of di ball and explode in anger wen Szymon Marciniak blow for foul. 78 mins: Half-chance! Rodrigo de Paul (Argentina) play one pass into di box, but Hugo Lloris react well to snuff out di attack. 80 mins: Kylian Mbappe (France) go take di penalty! 80 mins: Goal! Kylian Mbappe (France) fire di penalty home! 82 mins: Goal! 2 - 2 Na goal! Kylian Mbappe (France) introduce imself wit a fine finish. 87 mins: Marcus Thuram (France) gbab yellow-card for breaking di rules of di game. 90+1 mins: 8 min. extra-time. 90+3 mins: Fantastic run and shot from mid-range by Kylian Mbappe (France), but one defender deny am. 90+4 mins: Adrien Rabiot (France) run onto one loose pass inside di box and release one ogbonge shot low towards di middle of di goal. However, Emiliano Martinez anticipate dishot and make an easy save. 90+7 mins: Lionel Messi (Argentina) collect one low pass just outside di box and unleash one fine strike towards di roof of di net. 90+9 mins: Di referee don end di second half. 91 mins: Dem don begin play extra time to determine di winner of di match. 92 mins: Marcus Thuram (France) no dey obviously follow di Golden Rule: ""Treat odas as you want make dem treat you.“ Im make one bad challenge and leave Szymon Marciniak wit no oda option than to blow for a foul. free kick to Argentina. 94 mins: Dem penalise Lionel Messi (Argentina) for holding. Szymon Marciniak. 95 mins: Szymon Marciniak get a clear sight and see one foul from Marcos Acuna (Argentina). 96 mins: Di referee stop play so dem fit make substitution and Youssouf Fofana (France) replace Adrien Rabiot. 97 mins: Kylian Mbappe (France) dey forced to stop im forward run afta linesman catch am for offside position. 98 mins: Kingsley Coman (France) deliver one fine lofted cross into di penalty area, but one opposing player clear am off. 99 mins: Randal Kolo Muani (France) find im way past challenges, but one opposing player do well to get di ball away. 101 mins: 'Kingsley Coman (France) float di ball in from di corner but dem stop am. 102 mins: Di manager make a subsitution wit Lautaro Martinez (Argentina) coming on for Julian Alvarez. 106 mins: Lionel Messi (Argentina) whip di ball from one corner but one of di defenders clear am off. 106 mins: Szymon Marciniak blow for di start of di second period of extra time. 109 mins: Goal One rebound wrong foots everyone except Lionel Messi (Argentina), and im slam di ball into di open net from close range. Argentina 3-2 France 118 mins: 3 - 3GOAL! Great strike from di spot by Kylian Mbappe (France) into di left of di net, dey give goalkeeper Emiliano Martinez no chance! 120+4 mins: Di referee blow for di end of di second period of extra-time. Time don reach for penalty kick. 121 mins: Goal! Emiliano Martinez get a hand on di penalty from Kylian Mbappe (France), but no fit stop am from flying inside di left post. 121 mins Goal! Lionel Messi (Argentina) win di battle of wills and send one unstoppable penalty pass Hugo Lloris into di bottom left corner. 121 mins: Kingsley Coman (France) place di ball on di penalty spot and send am towards di bottom left corner. 121 mins: Paulo Dybala (Argentina) step up to take di penalty and convert am wit a low shot into di middle of di goal. 121 mins: Leandro Paredes (Argentina) execute di penalty kick wit ease. 121 mins: Aurelien Tchouameni (France) no fit convert di spot kick. E go narrowly wide of di left post. 121 mins: Gonzalo Montiel (Argentina) slide di penalty home!" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cneg9wpxzdlo +politics Trump tapes: US President Donald Trump tell Georgia election official Brad Raffensperger to 'find' votes, cancel Joe Biden win "Dem don record di US President, Donald Trump, as im bin dey tell Georgia top election official to ""find"" enough votes to cancel di election result. ""I just want to find 11,780 votes,"" Mr Trump tell Republican Secretary of State Brad Raffensperger inside one recording wey Washington Post release. Mr Raffensperger reply for di audio say Georgia results dey correct. Joe Biden win Georgia alongside oda swing states, im win 306 electoral college votes to Mr Trump 232. Since di 3 November vote, Mr Trump don dey allege say wuru-wuru dey di election without providing any evidence. All 50 states don certify di election result, some after recounts and legal appeals. So far, US courts don reject 60 challenges to Mr Biden win. Congress go soon formally approve di election result on 6 January. Mr Biden, wey be Democrat, go dey inaugurated as president on 20 January. Meanwhile, voters for Georgia go vote again on Tuesday to elect two senators for di state. The result fir determine di balance of power for di Senate. If the two Democrat contenders win, den dia go be equal numbers of Republican and Democratic senators, and Kamala Harris, di Democratic vice-president-elect, go get di deciding vote. Mr Biden Democrats already dey control di lower House of Representatives. Wetin happun during di Trump call? For di audio wey Washington Post release, pesin go hear as Mr Trump dey tok to Georgia secretary of state, dey apply pressure. E insist say e win di election for Georgia and tell Mr Raffensperger say ""nothing wrong if you say you don recalculate"". Mr Raffensperger respond say: ""Di challenge wey you get Mr President na say di data wey you get dey wrong."" Later for di call, Mr Trump say, di rumour na say dem tear up some ballots and comot some voting machines from Fulton Countyfor di state - but Mr Raffensperger lawyer don say dat one no happun. Di president come threaten di official with possible legal consequences. ""You know wetin dem do and you no dey report am. Dat na criminal offence. You no fit let am happun. Dat na big risk to you and to Ryan, your lawyer,"" Mr Trump tok. E come call for di extra 11,780 votes - wey for give am a total of 2,473,634 votes for di state, one more dan Mr Biden, wey receive 2,473,633 votes. E tell Mr Raffensperger to re-examine di result for di state. ""You fit re-examine am, but re-examine with pipo wey wan find answers, no be pipo wey no want to find answers,"" e tok. ""Mr President, you get pipo wey submit information and we get our pipo wey submit information and den e come before di court and di court get to conclude,"" Mr Raffensperger reply. ""We have to stand by our numbers, we believe our numbers dey right."" On Sunday Mr Trump tweet say Mr Raffensperger never give details of di fraud wey di president dey allege. ""E no get clue!"" di president tweet. Mr Raffensperger tweet back: ""Respectfully, President Trump: Wetin you dey tok no be true. Di truth go come out."" Di White House never comment on di release of di audio. But Kamala Harris call Trump comments ""a bold abuse of power.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-55526726 +entertainment Burna Boy lose Grammy 2020 Best World Music award to Angelique Kidjo "Angelique Kidjo don beat Burna Boy to win di 2020 Best World Music award for di Grammys. Dem bin nominate Burna Boy for di category for im ogbonge album 'African Giant'. Oda artistes wey dem nominate for di same category na Nathalie Joachim with Spektral Quartet, Bokanté & Metropole Orkest Conducted By Jules Buckley and, Altin Gün. Many fans bin dey reason say dis na di year wey Burna go gbab di award. But na di Ogbonge musician from Benin Republic, Kidjo, wey dey sing in more dan five languages win am, her fourth Best Contemporary World Music Album award for her album ""Celia"". Di ogbonge artiste dedicate di award to Burna Boy as she declare say Burna na part of di new generation of African musicians wey go take di world by storm. Supposing Burna win, e for be di second time wey Nigerian go dey gbab di award. Di first Nigerian to win na Sikiru Adepoju for 2009 with di ""Global Drum Project"" album e collabo do with Mickey Hart, Zakir Hussain, and Giovanni Hidalgo." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51260479 +sports Highest goal scorer in Euro 2020: Cristiano Ronaldo win Euro 2020 Golden Boot Cristiano Ronaldo win Uefa Euro 2020 Golden Boot wit five goals for di tournament. Ronaldo score dis goals in only four games during di Euro 2020 to finish as Top Scorer. Di Portugal striker first and second goal for di tournament na against Hungary for dia opening Group D match wey dem win 3-0. Dat take im, all-time EURO finals goals to new record of 11. Cristiano Ronaldo no stop dia im add one more to im total with di opening goal of dia 4-2 defeat to Germany on Match-day two. And then score twice from penalty spot for dia 2-2 draw wit France on Match-day three. Those two goals against Les Bleus take Ronaldo all-time goal scoring record for im kontri to 109 goals. E don equal di world-record mark wey former Iran striker Ali Daei bin set. And although di Czech Republic Patrik Schick also score five goals for di tournament. Ronaldo finish out in front sake of im assist against Germany, and also im play fewer minutes pass Schick. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57802235 +entertainment Ginimbi death: 'I want everybody wey wan attend my burial to wear white' - Genius Kadungure tok before e die "Family of popular Zimbabwean socialite and millionaire, Ginimbi Genius Kadungure - wey die for motor accident on 8th November say im want pipo wey wan attend im burial to wear white dress. Dis all-white dressing wey everybody must wear come di burial dey similar with Ginimbi trademark dressing for di lavish parties wey im dey always host while e dey alive. Di family say di wearing of white cloths na part of Ginimbi funeral plan and dem go do di burial for im mansion inside Domboshava on Saturday . During one interview with tori pipo, The Herald, Ginimbi eldest sister, Juliet tok say her brother use to tell dem say e want huge send-off. ""Genius na fun-loving character, e dey always remind us about how e want im funeral to be. In fact, e get di plan for ground and dey always tok say 'ndiri big', so make sure for my funeral, you no hurry-hurry bury me."" ""Take time to plan for my burial. Check my requirements well and one of di tins be say I want everyone wey go come my funeral to dress in all white, no mata who. Please, make sure you tok am plenti times. Remember, say I be all-white guy. Di all-white need to be on di day of burial."" Juliet say na wetin im brother, Ginimbi bin tell dem before e die. Juliet say according to di plan, dem go get to wait for Ginimbi oda friends wey dey abroad to come for di burial. ""Ginimbi go tok say, make sure you get in touch with my oda friends abroad and wait for dem to come. Dat na why we dey tok say for now di burial go begin on Thursday and for now pipo dey gada for our papa residence wey dey 400 metres away from Ginimbi mansion."" Madam Juliet say dem don set up one tent because plenti pipo dey com from all 'walks of life' and we no fit accommodate all of dem for di mansion. ""We go arrange one tent for friends and fans, then anoda VIP tent, we go bury Ginimbi on Saturday for im yard as e wish to. E dey very difficult for us as family and we dey kindly request di public to respect us and avoid spreading bad rumours. She add for now, we don put family spokesperson wey be Clement Kadungure. Anything you wan hear wey no come from am, no be true. Juliet tok say no be say di family dey stop pipo from mourning Ginimbi for im mansion, as social media dey report, but di reason why di funeral dey happun for di oda side na to accommodate everyone. ""You fit think say di yard dey big, but e no dey big to accommodate everyone as you know many pipo dey come,"" she tok. ""Like I tok, we don decide to pitch tents for di open space near my papa house. Na also for di security of dihouse."" Juliet tok say Ginimbi dey always wish make dem turn im house to museum or hotel upon afta e die. ""We go invite some local artistes so dat dem go perform on Friday wen im body go lie in state for im mansion,"" she tok. ""Remember, Genius na im own G-Entertainment wia e promote some local artistes, so we go do im wishes and dem go also dress in white."" Chief executive officer of Ginimbi G4K security company Dr Peter Gwaza, tok say some pipo dey come with di intention to tiff Ginimbi property. ""We don already catch two pipo wey don tiff plastic chairs,"" e tok. ""Again, di house get plenti property wey we need to protect. I respect di decision wey di family take to do di funeral outside di mansion."" Ginimbi Genius Kadungure na prominent businessman, chairman of Piko Trading Holdings plus Founder of Genius Foundation, and owner of Sankayi (AKA Dreams Nightlife Club). E get masters for Business Administration, e get get im MBA from di University of Great Zimbabwe." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54905831 +health Wetin di new Covid-19 guildelines for Nigeria mean for pipo wey dey travel by air? "Nigeria goment say wearing of Facemasks inside Airport terminal buildings and onboard aircraft by airport workers and passengers no dey compulsory again. Di only pipo wey facemasks dey compulsory for dem to wear na pipo wey dey 60 years and above. Nigeria goment tok as dem release di latest COVID-19 and public health guidelines for all Aviation service providers for domestic and international operations on Monday 12 December, 2022. Nigeria goment say dem bring di new guidelines sake of say COVID-19 for Nigeria and oda parts of di world dey low for a sustained period. So di Presidenial Steering Committee on COVID-19 get to revise di COVID-19 public Health guiduance for doemstic and international operations. Domestic Operations ""For Domestic operations, wearing of facemasks inside Airport terminal buildings and on board aircraft by airport workers, passengers and crew members no dey mandatory"" Goment say pipo wey dey 60 years and above dey advised to wear facemasks sake of risk of wetin fix spoilor affect dia immune system. ""Due to Organ transplant, Cancer, Heart disease, Diabetes mellitus, Hypertension dey advised to use facemasks, wash dia hands wit water and soap, use hand alcohol based sanitizers and make dem avoid large gatherings"" Oda tins wey go apply for domestic operations: International Operations COVID-19 travel testing for Pre-departure and Post-arrival no dey needed again for all pasengers, weda you take vaccine or not. PCR tests too for passengers wey no dey fuly vaccinated dey suspended. Everytin for domestic operations go apply for international operations. Health declaration form Permission to travel and QR code no dey needed again. Dem go issue one simple Health questionaire wey be non-COVID-19 specific to passengers wey dey come Nigeria to fill. Di pasengers go fill dis form before dem travel for di Nigerian International Travel Portal (NITP) Passengers wey no fill di form for NITP go fill am on board di aircraft or wen dem land for di airport terminal buildng. Nigeria no be di only African kontri wey don update dia COVID-19 guidelines. West African kontri, Ghana too update dia travel guidelines on 1 September, 2022. Ghana say all International passengers wey wan enta Ghana, including those from ECOWAS kontris need to dey fully vaccinated. Dem must also fill di Port Health declaration form. Ghanians from 18 years and above go provide evidence of full vaccination form. Wearing of facemasks still dey compulsory for Ghana. For Kenya no COVID-19 protocol dey again, as goment remove all di bans early dis year. No more PCR test for arriving passengers, and wearing of facemasks no dey compulsory. For South Africa, di Center for Disease Control (“CDC”) remove di order wey require pipo to negative COVID-19 test result or documentation of recovery from COVID-19 before dem board any flight to di United States." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn04qv7jy4no +entertainment Bashir El-rufai wedding: Kaduna state govnor i pikin don marry senator Kazaure pikin Bashir El-rufai, di son of Kaduna State governor, don marry im wife, Kalima Kazaure, wey be di daughter of Senator Ibrahim Kazaure. Di wedding happun on Sunday, October 21, 2020 for Nigeria capital, Abuja. Plenty politicians including Nigeria Senate president, Ahmad Ibrahim Lawan, dey di wedding. Oda important person wey dey na di Governor of Kogi State, Alhaji Yahaya Bello; and Governor of Yobe State Mai Mala Buni. Nigerians for social media don dey tok about di wedding since wen Bashir release some of im pre-wedding pishures wey cause kasala for Twitter. According to some pipo wey react to di pishures, dem say e dey wrong for di bride to leave her hair open while odas also tok about how di govnor pikin grab im wife to be from behind. Dis no be di first time wey Bashir dey see controversy on top Twitter, e get time wey e call former Ekiti govnor Ayo Fayose 'vagabond' wey some pipo see as lack of respect. E also get time wey e throw shade to former vice president Atiku Abubakar pikin Mustapha because say im father tok say parents must teach dia children to respect women. Di wedding go happun on Saturday, 21, November, 2020. Her name na Halima Nwakaego Kazaure and her father na from Kazaure local goment for Jigawa state wey dey northern Nigeria. While her mother belong to di igbo tribe from south eastern part of Nigeria. For one tweet wey she post on twitter, she say her mother na Igbo and her papa na Hausa but di most important tin be say she be Nigerian https://www.bbc.com/pidgin/tori-54985851 +politics Nana Addo Dankwa Akufo-Addo: Ghana President Nana Akufo-Addo address de nation ahead of elections on Monday Nana Addo Dankwa Akufo-Addo, Ghana President dey address de people of Ghana by 8pm Accra Time on Sunday. Dis nationwide address na wetin de president wan to tell de country ahead of dia 7 December election. Click here to watch: https://www.bbc.com/pidgin/world-55198003 +business Marwako apologize to customers for Ghana wey suffer food poisoning after dem patronize dema restaurant "Fast food company for Ghana, Marwako extend apologies to customers wey suffer food poisoning after dem patronize dema food. After initial inquiry into de complaints, de fast food company say dem identify about 53 people wey fall victim to food poisoning. Food and Drugs Authority (FDA) shut some of dia branches down over alleged food poisoning allegations after some Twitter users call de Company out on top social media. Spokesperson, Mohammed Amin Lamptey explain say ""de main tin start on Saturday den Sunday evening. We accept everything, we apologize to de victims."" He add say dem also reach out to de victims to support dem and pay for some of dia medical bills. Food and Drugs Authority for Ghana shut down three branches of de fast food chain after social media reports emerge say some customers including kids experience food poisoning. Although de incident happen for dema East Legon branch, de FDA say dem shut de East Legon branch and two other branches which no dey adhere to good kitchen den storage practice. According to FDA, ""we go investigate dis matter well-well den make sure say we take appropriate actions. One Twitter user after reporting to de hospital for stomach pains reveal say en troubles start after he eat for Marwako. After dis tweet, more Twitter users come out to explain dema own experience with food poisoning and diarrhoea. After dis tweet, more Twitter users come out to explain dema own experience with food poisoning and diarrhoea." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61434202 +health Covid-19 update: Ghana dey ready for de 2nd phase of COVID-19 vaccination, see if you qualify "Head Ghana dey roll out second phase of COVID-19 vaccination dis week. President Akufo-Addo reveal say on Wednesday, May 19, 2021 to May 26, 2021 de Ghana Health Service (GHS) go start dey give 2nd dose of vaccines. Dis be 12 weeks after de first vaccination exercise wey happen but Prez Akufo-Addo explain say no be everyone wey take de first vaccine go take de second. De second phase of vaccination according to de Ghana Health Service dey target some 300,000 people. According to de GHS, de second phase dey target people who take dema first shot between March 1 and March 9, 2021. Director of Public Health, Dr Franklin Asiedu-Bekoe talk BBC Pidgin say ""we dey look at people who collect de first shot from 1st March to 9th March, 2021."" ""After that when we get de new consignment and we go continue with de rest"" he add. He explain say if dem open give everybody confusion go happen, so dem dey deploy mechanism to notify only those who dey qualify to come. ""We know de names of those we vaccinate so we go send dem SMS. We also go give announcement say make people check dema cards, to know if dem dey fall within de date announced."" On de day of de vaccination, nurses go also dey on ground to check de dates on vaccination cards to ensure say only de right people dey get de vaccine. More vaccines dey come Ghana dey expect some extra 300,000 Sputnik V vaccine which de Food and Drugs Authority already been approve according to Prez Akufo-Addo." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57148675 +entertainment Angel BBNaija ex-housemate exclusive: 'Why I no dey place my value on pesin wey see my body’ "Angel Smith, one of di housemates for di Big Brother Naija, season six 'Shine Ya Eye edition' of di show siddon with BBC Pidgin afta di end of di show to tok about her journey and to clear di air on some issues wey hapun during di show. Angel wey make top five and be di fourth runner up for di season six edition of di show tok for dis exclusive interview say making it into di finals sweet her die as she bin no expect am and she dey grateful. ""I be smart woman I don already sabi say probability to win for me no too sure, I bin just one make am into finals and once I enta top five I be like omo e don set for me be dat. "" She tok. Angel also clear di air about issue wey bin come up and audience bin dey tok about like her bathing with guys and her relationship with dem for di house. ""No be strategy, di bathroom sef na communal bathroom, dem tell us say we suppose bath togeda. But based on say oda girls no too wan do am e come look like say I just dey do am make I enta dey bath with boys. ""No be strategy, for me na how I be, I dey very very comfortable, all those tins no too dey freak me like dat, I no dey place my value for pesin wey see my body, I dey place my value on tins wey dey my head, I smart boost."" Because say you don see my body no mean say one tin one tin, e just mean say you don see my body and na wear e dey be dat."" Angel tok. On her quarrel with fellow housemate Boma, Angel say she no wan dwell on negative tins. ""Di blame no be from me, anybody wey watch di video don tok say naim start am and na based off of my age. I be 21 so e no too reason me as anything e just dey reason say I be small girl so any small tin, I be small girl, but like I said I no wan involve myself for anything negative so if e say na me start am den na me start am at di end of di day e no fit beat me, and wetin don hapun don hapun and I no too dey stress like dat, I no reason am becos say we no dey follow each oda and tok no mean say na beef, no be beef."" She tok. Angel togeda with oda housemate Saskay na di youngest at 21 for di season six house. For Angel, dat one no hinder her at all. ""I no go lie to you, interacting with dem dey easy for me becos before I enta di house na mostly older pipo I dey tok to so e dey easy for me to blend but I no know for dem becos sometimes I dey feel say e get sometins dem go tok and I go reason say na becos I be 21, but for me e no really to shape anything."" Angel bin trend well-well during di course of di show becos of her interaction with di guys and especially di plenti kisses she share with not one, two or three of di male housemates for di house. But for Angel all na cruise maybe except for one pesin ""Na cruise oh, I just go di house go catch cruise ."" I no know weda dem forget say na Tv show and na reality and we suppose entertain."" On her relation-ship with Cross, Angel say: ""Becos our personalities dey kain of alike we be kain of di same pipo we dey always run tins, we be best friends, some kain of feelings involve, but e be situation wey I no wan push, I no dey like push tins, if e hapun and e want make we work, e go work, and if e no hapun and e no want make e work, cool too. Chemistry dey, but promise no dey say anything go hapun."" She tok. On some misconception fans of di show get about her, especially relating to her mental health, Angel clear di air also. ""Dem tink say di mental health tin I dey always tok or di way I be no be di way I be outside, dem tink say di mental health tin na pity card, No be so, why I go want make pipo troll me with mental health? I tink dat na one tin pipo no get about me. Dem also tink say I be loose babe becos I dey kiss plenty guys, dem dey call me slut, ashewo, but dat one eh, I dey still dey chill becos I don hear am before, dem no know me and I no dey use my sexual expression as how I dey judge myself cos I know say I smart die and those wey know me know me and those wey no know me no know me period!"" Angel tok. Angel also talk more about how she self-harm becos of mental health issues, sadness, depression and loss wey she suffer. Click here to watch di full interview." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58836258 +sports Felix Afena-Gyan: Ghana boy wonder, who set record with AS Roma for Italian Serie A "Ghanaian boy wonder, Felix Afena-Gyan turn football sensation inside Italian top side AS Roma. De teenager score two goals to secure all three points for Coach Jose Mourinho on Sunday in dema game against Genoa. Felix Afena-Gyan make en professional debut only three weeks ago for AS Roma. He score de two goals during en third appearance for AS Roma. Dis be after Jose Mourinho promote am few months after he join Roma youth team Roma Primavera. During en time with Roma Primavera, he score six goals in just five games. He join de Roma youth academy in January dis year after scouts discover am while he dey play high school football. De teenager after de game talk say ""I get de feeling say if I get one minute I go score for de club. God being so good I do am."" Born in January 19, 2003 for Sunyani inside Ghana. De teenager who dey play high school football impress scouts who quickly fly an to Italy to join de junior team side of Roma. He join de Roma junior side on March 13, 2021. Just a day after he join on March 13, de youngster show class after he score and provide assist for in en first game. He continue to display class, as he record goals in en next two matches for Roma junior side. After news of en football talent spread reach Jose Mourinho who observe de teenager closely, he quickly promote am to de senior team AS Roma. He make en professional debut on October 27, 2021. Only three weeks after en first appearance, de teenager set record as de first player born in 2003 to score not just one goal but two goals for de league. Football fans dey hail am for de impressive performance off de bench for de club while dem dey struggle to score against Genoa. So far he record 2 goals in 3 appearances for AS Roma. After de game he tweet, ""I love you mum, dis be for you."" AS Roma Coach Jose Mourinho say he promise de teenager say he go buy am expensive football boot wey sake of en performance he dey fulfil that promise. ""I promise to buy Felix de boots he dey like pass, dem be very expensive, dem dey cost €800, so he ran to me talk me say make I no forget!"" ""Morrow morning, de first thing I go do be say I go buy am de boots"" he add. According to de top coach, Felix be player wey get fantastic technique and strong mentality. ""You get dis kids who feel say dem know everything, but he be humble. You dey see say he dey absorb every information from everyone around am,"" Mourinho talk. According to Mourinho, ""what impress me de most be say he get cool head in front of goal...he get strong mentality.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-59370786 +entertainment Erica: BBNaija Kiddwaya mama Susan Waya surprise visit to ‘Elites’ meet and greet and ‘Kiddrica’ toks dey totori fans "Fans go gaga afta one video wey show Susan Waya mama of Big Brother Naija lockdown former housemate Kiddwaya show for one Erica meet and greet event for Abuja on Friday night. Di fans wey gada to meet Erica surprise to see Kidd mama. She say ""today na special day because I have to celebrate and welcome two pipo to Abuja, my son, Kiddwaya and di Elites - Erica fans come Abuja. Susan Waya wey hug Erica support di Elites and di ""Kiddrica"" ship wey sail for di house. She add say ""I dey see myself for dis little lady and I dey here to support her. I no fit replace her mother but she na my daughter. And today, I wan confam to you say, I be Kiddrica"". Kiddrica na Kiddwaya and Erica name wey pipo wey dey root for dem and dia relationship join togeda and dem dey call themselves Kiddrica shippers. Wetin Kiddwaya mama tok make dem happy and many pipo don dey comment on top di mata for social media. After her speech, she hug and kiss Erica. Erica, na one of di 20 housemates wey enta di Big Brother Naija Season 5 Lockdown house before dem disqualify." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54399663 +health Coronavirus in Cameroon: How Covid-19 di affect Anglophone IDPs for Yaounde Gham Mercy na one of de many pipo weh deh run crisis from Northwest and Southwest regions kam for Yaoundé. Anglophone crisis start for 2016, turn to fight between separatist fighters and goment forces. About 600,000 pipo run go oda areas, 40,000 for Nigeria, over 3000 pipo don die. Mercy laik many IDPs for Yaoundé di stress first for survive, deh no get beta place for stay even as deh di cope with effects of coronavirus. For seka measures weh goment take for block de sick, Mercy loss e work, but e di hope for learn business for do. Producer: Leocadia Bongben https://www.bbc.com/pidgin/media-52661892 +politics Nigeria Vice President, Professor Yemi Osinbajo neva declare interest to be President for 2023 "Office of di Vice President of Nigeria don deny any connection wit one volunteer group wey dey mobilise support for Professor Yemi Osinbajo for di 2023 presidential election. Inside statement wey di VP office release, dem tok say dem no get any connection wit di group and say wetin di group dey do na ""unnecessary distraction."" ""Prof. Osinbajo neva eclare any interest at-all at-all for di 2023 election, but instead im wan focus on working for im capacity as Vice President for di current goment to address all di serious issues for di kontri and tins wey dey worry Nigerians, plus to find permanent solution to di security challenges."" One group, di ""supportosibanjo.ng group"" dey try ginger Nigerians to come join dem support Osinbajo for di 2023 presidential elections. Details about di group website and di advert for pipo to join dem dey currently trend for WhatsApp and dem claim say di VP don ""quietly"" declare interest for di coming election." https://www.bbc.com/pidgin/media-57146875 +politics Kenya Election 2022: Why di count dey take so long "Kenyans still neva know who dia next president go be more dan 45 hours afta voting end. Head of Kenya Election body Wafula Chebukati don beg pipo to dey patient and no panic as media dey release results. Each media organisation dey do dia own calculations based on di manual entry of data from more dan 46,000 polling stations. But na only di electoral commission fit declare di winner. Di media tally say di two leading candidates - Raila Odinga and William Ruto - dey neck and neck. ""Make nobody panic about di differences wey media dey show us. Di results na from di same public portal; di approach [of each broadcaster] dey different,"" oga Chebukati tok. E say at di end of di collation, di result fit dey ""similar"". Teams of tori pipo wey dey work for different organizations dey do di difficult work of uploading di figures dem receive from each of di polling stations one-by-one. Each media house dey do different speed and choose di polling stations in different order. Wen e come to di electoral commission, on top of compiling di results, officials need to verify each one - anoda time consuming task. Officials dey currently compare di results wey di commission receive in di form of foto from di polling stations wit di actual results sheet, wey dem dey hand over to di collation centre for di capital, Nairobi. Dis na to ensure say di two results match and a key reason why tins dey take so long. Counting for some polling stations dey delayed and travel go Nairobi, especially by agents from far-flung areas, fit be for oda reasons wey dey slow tins down. Anxiety dey di kontri as past elections don lead to violence or di whole process fit dey cancelled. Sake of di 2007 vote, at least 1,200 pipo die and 600,000 run from dia houses based on allegation say dem do mago-mago for di election. For 2017, big problem come out wey make di Supreme Court to nullify di result and order re-run for di presidential election. Officials dey under pressure to do tins well dis time. Nothing dey usually happun for di kontri during elections, activities across di kontri don slow down and schools remain closed at least until next week Monday. For Nairobi central business district, di usually busy streets dey empty. Allegations of election rigging na old mata for di kontri. E follow for politics even before di introduction of multiparty elections for 1990s, but di push for free and fair elections neva fail. Afta di violence wey happun for di 2007 election, political parties and activists argue for di use of technology instead of physical registers, wey fit dey easily manipulated, to verify voters. Dis year election na di third time dem go use technology but e neva still deliver a election wey dem neva challenge for court. Early report, however, suggest say di electoral commission fit finally achieve dis goal wit dis election. Wit di speed of di counting wey dey ongoing, di local media dey likely to conclude dia own collation of results before di end of Thursday. If clear leader emerge for di race, celebrations fit start. However, only di electoral commission fit declare winner afta comparing and verifying di results. Di electoral commission get seven days afta election day to declare di result. To win di presidential race for di first round, a candidate need: If not, voting go enta second round wey by law must happun by 8 September." https://www.bbc.com/pidgin/tori-62508390 +entertainment Ladin Chima: Kannywood actors react after actress say she no dey earn pass N2,000 for movies For pipo wey dey follow northern Nigeria movie industry wey dem dey call Kannywood, Ladin Chima na one of di actresses dem dey familiar with. She dey always play motherly roles and she don act plenty movies in over five decades. Wetin make her enter news na di interview she do with BBC wia she tok say sometimes na N2,000 she dey get for her acting. “Since i start to act up till now i neva colet big money sometimes N5,000or less even today i comot go act movie and wetin i get na just N2,000.” “Na inside dat money i dey feed 8 pipo wey dey depend on me for food.” Di Katsina born actress say she almost go homeless recently because dem tell her to vacate di house wey she dey live and she no get any oda plan. “I bin for goment for sometime as a staff of Nasarawa hospital and after i retire i gaz leave di quarters for dem so dat ting almost make me homeless.” “Di reason na say di money wey i dey make from acting too small for me to save to build my own house, how i wan begin save N2,000 to build house.” Some ogas for Kannywood react to wetin di actress tok and say on dia part dem dey pay her reasonably well anytime she act for dem. Ali Nuhu wey be di most popular actor/producer for di industry tell BBC say e dey wrong of Ladin Chima to generalise when she know say no be all producers dey treat her poorly. “Wetin she tok dey wrong because no be every producer dey like dat in my own case she act movie for me recently and I pay her N40,000 for her services.” “Wetin she yan cause some pipo to dey abuse me thinking because she act film for me recently.” Anoda top producer Falalu Dorayi say wetin Ladin Chima tok surprise am because e don act several movies with her and neva for once pay her less than N20,000. “In fact she act for me less than 10 days ago and wetin i give her na N30,000 so wetin she tok surprise me.” “Even for my series film she act five scenes and i give her N40,000 and when her home wahala start Kannywood pipo contribute almost a million naira for her.” BBC reach out to di actress after di two biggest bosses in Kannywood tok dia side and she tok say e get producers wey dey treat her right on di side. She yan say some like Falalu Dorayi dey follow her go house to dash her money. “Producers like Ali Nuhu dey come house to dash me money dat one dey even recently actress Hadiza Gabon dash me N300,000.” “Even house wey I dey na dem contribute money buy for me.” Dem born Ladin Chima for Katsina state many decades ago and di actress say she begin act during di administration of General Yakubu Gowon in di 1960s. She say her parents marry her off at di age of 13 but gave birth to her first pikin at di age of 17 before oda two children follow. Na di death of her first husband make her enter movie industry as already she get interest and passion for long. She don act for hundreds of movies and some dey call her di Ngozi Ezeonu of Kannywood as she mostly dey play good mother. https://www.bbc.com/pidgin/60345873 +entertainment Bunny Wailer: Jamaican Reggae legend wey play with Bob Marley don die One of reggae most important voices, Bunny Wailer, don die for di age of 73. Di musician wey come from Kingston, Jamaica, na founding member of The Wailers, wey go on to find international fame with Bob Marley. Manager Maxine Stowe, and Jamaica Culture Minister, Olivia Grange na dem confam di death of Bunny Wailer. Di cause of death no dey known, but e bin dey for hospital since e get stroke for July 2020. Bunny Wailer na one of Bob Marley childhood friends, e work on im first two albums, Catch A Fire and Burnin', before e go solo for 1974. E go continue with e singing to win three Grammys and dey give am Jamaica Order Of Merit for 2017. Bunny Wailer wey e real name na Neville O'Riley Livingston, na di last surviving member of The Wailers, afta Bob Marley die from cancer for 1981, and Peter Tosh murder during one robbery in 1987. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56256402 +entertainment Antwain Lee Fowler: Celebrities, odas mourn di death of 6-year-old viral video star "Antwain Fowler, one 6-year-old wey dey popular for asking im mama : ""Where we 'bout to eat at?"" for one video wey gather millions of views online, don die. Na Antwain official Instagram account confam di news on Sunday wit one message ""Di pain for my heart na like no other Why God!!!!!!!!!!!!"". E dey likely say na Antwain mama, China na im share di post for im Instagram page Di caption wey follow di post na ""Never in a million years My heart dey out my chest!!!!"" E no dey clear wetin be di official cause of im death but e fit dey related to Antwain ongoing battle wit autoimmune enteropathy, One rare disease wey dey make intestines no dey function well and e dey also limit the amount of nutrition wey di body fit take. Dem diagnose Antwain wit di sickness as a baby for 2015. From im official GoFundMe page, Antwain don do 25 surgeries in di course of im young life, E no fit take solid foods or drink milk during im early childhood. China, wey be im mama also upload one separate message for her personal account on Sunday afternoon. ""Ever felt lifeless like you no fit go on. I no wan dey here anymore , I no fit bear dis pain dat na my babyyyyy my god why me ‼️‼️‼️,"" she write am. Since she share di post many pipo don enta social media to mourn Antwain death. ""Rest Up Young King,"" one NFL cornerback Deandre Baker write. ""Di coolest kid wit di most happiest soul, I no fit believe am,"" rapper Famous Ocean write. Popular Nigerian comedian, Lekan King Kong write say ""I dey so sad, journey well Champ, rest In perfect peace"" ""So sorry for your lost. God go comfort you"", Official Arole write. ""What a beautiful & powerful soldier. You dey so loved @_antwainsworld,"" writer and producer Danielle Young comment. ""You put up a good fight baby now take your rest peacefully Rest In Peace Antwain Lee Fowler ,"" another pesin write." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59370783 +sports Transfer rumours on Pogba, Jesus, Richarlison, Rice, Coutinho, Gallagher, Carrick Juventus don ready to offer Manchester United and France midfielder Paul Pogba £8m per year, wey go be like £160,000 per week, including beta bonus package and signing-on fees. Pogba contract go expire dis summer and Manchester City too dey eye am. (Mirror) Manchester United dey tink to sign 25 year old Frenkie de Jong from Barcelona wey go cost dem £75m. (ManchesterEveningNews) Chelsea dey toast 21 year old Barcelona and United States defender, Sergino Dest. (Sport - in Spanish) Gabriel Jesus agent don confam say di 25 year old Brazil and Manchester City striker don dey tok with Arsenal for possible transfer. (Guardian) Manchester United summer transfer plans dey scattered afta di three midfielders wey don reject di move to Old Trafford. (Star) Tottenham dey interested in three Everton players. Dem be Brazilian forward Richarlison, 25, English winger Anthony Gordon, 21, and 24-year-old English defender Ben Godfrey. (Telegraph - subscription required) Spurs dey also eye Leicester and Belgium midfielder Youri Tielemans, 25. (GiveMeSport) Dimitar Bebatov don tell im old club Tottenham make dem no only focus on di mata say top England Captain Harry Kane wan waka dis summer because top clubs go dey eye South Korean striker Son Heung-min, 29 too. (London Evening Standard) Dem don tell Manchester United to cough out £85.5m if dem wan sign Nigerian striker 23 year old Victor Osimhen comot Napoli dis summer. (Calciomercato, via Four Four Two) West Ham don drop offer of eight year contract wey worth £200,000 per week to keep 23 year old England midfielder Declan Rice wey Chelsea and Manchester United don dey target. (Talksport) But Rice no go gree West Ham offer. (GiveMeSport) Meanwhile, di Hammer wan sign Aston Villa and England forward Ollie Watkins, 26. (Mail) Wolves don signal say dem fit sign Sporting Lisbon and Portugal player Joao Palhinha, 26 if 35-year-old Portugal midfielder Joao Moutinho comot. (Jornal de Noticias - in Portuguese) E remain small make Aston Villa announce permanent signing for Brazil and Barcelona playmaker Philippe Coutinho, 29 wey don dey on loan for Villa Park since January. (Fabrizio Romano) Everton dey tink to sign Manchester City and Republic of Ireland goalkeeper Gavin Bazunu, 20. (Irish Independent) Leicester dey ginger to sign Club Bruges and Belgium midfielder Charles de Ketelaere, 21. (Corriere dello Sport - in Italian) Manchester United go need pay di release clause for RB Leipzig and Austria forward Konrad Laimer of £34m if dem wan sign di 24 year old. (Transfermarkt - in German) Crystal Palace wan sign Chelsea and England midfielder Conor Gallagher, 22 permanently afta im gbab di club Player of di Season wen e dey on loan for di club. (Talksport) Former Manchester United and England midfielder Michael Carrick, 40 be di most likely to be di next Lincoln City Manager. (Football Insider) https://www.bbc.com/pidgin/sport-61404974 +politics "Ukraine vex as Macron say ""no humiliate Russia""" "Ukraine foreign minister don hit out on French President Emmanuel Macron aft aim tok say e dey important say Russia no chop humiliation over im invasion. Oga Macron bin say e dey critical for President Vladimir Putin to find way out of wetin im call ""fundamental error"". But Dmytro Kuleba say make im allies ""beta focus on how to put Russia for im place"" as e ""humiliate imsef"". Mr Macron has repeatedly spoken to Mr Putin by phone in an effort to broker a ceasefire and negotiations. France attempt to maintain conversation wit di Kremlin leader contrast wit US and UK positions. Foreign minister Kuleba tok for im tweet say ""call to avoid humiliation of Russia go only humiliate France and every oda kontri wey go call for am."" Kyiv say Russia must not collect any territory from Ukraine, as many kontris condemn Russian invasion as brutal aggression. Earlier, Oga Macron tell French regional media say Russia leader ""isolated imsef"". ""I tink, and I tell am, im make historic and fundamental error for im people, for imsef and for history,"" im tok. ""Isolating yourself na one tin, but to dey able to comot from am na difficult path,"" im add. Italy Prime Minister Mario Draghi don join imsef wit Macron, suggesting say Europe want ""some credible negotiations"". The eastern city of Severodonetsk remain di centre of fighting for Ukraine, as Ukraine forces dey seriously resist Russia tanks, foot soldiers and serious artillery attacks. Capturing di city go deliver di Luhansk region to Russian forces and dia local separatist allies, wey dey also control much of neighbouring Donetsk region. Di region Ukraine govnor Serhiy Haidai say im forces don reclaim about one fifth of Severodonetsk and dem fit hold on. ""As soon as we get enough Western long-range weapons, we go push dia artillery away from our positions. And den, believe me, di Russia soldiers, dem go just run,"" im tok. US dey plan to give Kyiv forces precision rocket systems, so dat dem go fit hit Russia positions from longer range. UK go also send dem some large multiple-rocket batteries. Facing Severodonetsk across di Siverskyi Donets river na Lysychansk. Both cities dey strategically important for Russia: Severodonetsk get di giant Azot chemical plant, wey dey produce nitrogen-based fertilisers, and Lysychansk get Ukraine second biggest oil refinery. Di fighting now don destroy most of Severodonetsk, but thousands of civilians still dey shelter for basements dia. Governor Haidai say Russia forces bin dey blow up bridges on di river to prevent Ukraine from bringing in military reinforcements and delivering aid to civilians." https://www.bbc.com/pidgin/world-61689987 +politics 'Bishops at APC unveiling': Who be di Christian clerics wey attend Kashim Shettima unveiling as APC vice-presidential candidate? "Some priests attend di unveiling of Kashim Shettima as di vice presidential candidate of di All Progressives Congress (APC) on Wednesday and generate reactions as pipo describe dem as fake. Di reactions dey come on di heels of di backlash wey follow di ruling party muslim-muslim presidential ticket. Kashim Shettima wey be Muslim from di north dey run alongside Bola Ahmed Tinubu, anoda Muslim from di southern part of Nigeria- dis decision to field Muslims as presidential and vice-presidential candidates don already dey generate plenti tok-tok for di kontri. Christians communities through CAN don condemn am as dem believe say e no dey fair to dem. BBC Pidgin speak wit some of di priests wen dem arrive di unveiling for Abuja and di only tin dem tok be say na from di Nigeria College of Bishops dem come from. For some of di videos wey dey trend on social media, some of di priests decline to speak wit di press and dis one and oda reasons make pipo believe say e get wetin di priests dey hide. Di Vice President of di Christian Association of Nigeria (CAN) for di 19 Northern States and Abuja, Joseph Hayab tok say dose pipo no be real bishops and say na pesin hire dem to dress as priests. Gunmen kidnap two Catholic priests inside Nigeria ""I tink di pesin wey bring dem no do beta job. Dem just give dem clothes make dem wear am as bishops. Dis rehearsal dey poorly rehearsed and di pipo just make mockery of dem,"" Hayab tok. Hayab tok say bishop for every denomination get di way dem dey dress and di ones wey attend di unveiling no dress well. E say CAN no care about di choice of APC to field Muslim-Muslim ticket sake of say na mata of choice. However, for one of di trending videos, one pastor identify imsef as Bishop Igbokwe Prince and senior pastor of di Yoke Breaker Prophetic Ministry for Abuja. E tok say dem attend di unveiling of Shettima to show solidarity for di ruling party ahead of di 2023 general elections. Bishop Prince also tok say im be founder of Muslim and Christian Love International Foundation wey believe in di unity of Nigeria and religious harmony. ""We dey hear to show solidarity, pray and advise for di party to get am right in 2023,"" di cleric tok. Although no law for Nigeria dey against Muslim-Muslim presidential ticket but sake of say Nigeria na secular kontri, pipo expect say di choice of presidential candidate and im vice go spread across di two main religion - Muslim and Christian. Dem believe say religion don divide di kontri well-well and any decision wey politicians dey make no suppose favour one religion ova di oda. Some pipo wey dey against di Muslim-Muslim ticket feel say e no dey fair to Christians to get Muslim president and vice president." https://www.bbc.com/pidgin/62248879 +entertainment Travis Barker: Kourtney Kardashian announce engagement after proposal for beach Former reality TV star, Kourtney Kardashian don finally accept proposal. Dis na as her bobo of less than one year, Travis Barker propose to am on Sunday. Tori be say im pop di question for beach for California, wey im involve all her family members before hand. E happun afta dem bin just land from dia trip to New York wia oga Barker bin go drum for Saturday Night Live. Many pipo don dey hail di 42 year old model most especially her family members wey join am to break di news. Na for February 2021, dem tell di public say true-true dem dey date afta months of speculation. Even sef di way di fire catch for dia relationship shock pipo wella, as Kourtney normally na pesin wey no dey like tok abut her relationship. Kourtney currently get three pikin with her ex-boyfriend, Scott Disick wey dem don dey since 2006 - Mason, Penelope and Reign. 45 year old Travis Barker na popular rockstar wey dey with di band Blink-182. E don marry two times before, first to actress Melissa Kennedy and then to model Shanna Moakler. E get two children out of im last marriage wit Shanna - Alabama and Lander. As we tok before, di way Kourtney post lovey-dovey pictures from February for social media togeda with couple besties actress Megan Fox and rapper Machine Gun Kelly. Di rumours bin start around 2019 but at dat time Travis bin say na just friends dem be. Howeva, dem start dey post pictures just afta Valentine Day like say tomorrow no dey and even rom June, proposal rumour don dey fly up and down. https://www.bbc.com/pidgin/world-58929070 +sports Man United v Tottenham: Who VAR help? Why Wenger, odas get kwanta wit am "As Jose Mourinho dey return to Old Trafford on Wednesday almost one year afta dem chase am comot dia, one mata wey go dey pipo mind na which kain kwanta VAR go cause for di ogbonge matches. VAR don cause controversy well well for Premier League and Mourinho imsef na pesin wey from time don para unto officials decisions wey im feel say no correct. But di last time wey Mourinho coach for Premier League nothing like VAR bin dey for England. Mourinho former rival Arsene Wenger, wey don become Fifa new head of global football development, don already criticize why referees no dey use monitor wey dem put for field for dem. ""Di referee need monitor to check if im dey right or wrong... For me, dis na di most important worry,"" Wenger tok. Tori don comot for media of Premier League players wey no like VAR or how officials dey use am for matches. Although we no get data to support dis, e be like many of Manchester City players don complain well well about am. From Kevin De Bruyne, to Raheem Sterlin to Ilkay Gündogan. Dis no be to say players from oda teams never para about am. Liverpool midfielder James Milner no dey hide am say im no like VAR at all. Many players feel say las las, VAR still no dey get di correct decision. Former players sef don chook mouth for di mata. For November 2019, Chelsea coach and former midfielder, Frank Lampard draw ear give anybody wey wan hear am say VAR fit dey ""dangerous"" for di Premier League. Lampard own be say e too dey take time. Premier League legends like Alan Shearer, Robbie Fowler and Phil Neville no happy at all wit di way tins dey go. Many fans don enta social media to show dia frustration wit VAR, especially wen decision no favour dia team. Although oda fans don use VAR kwanta to do play-play about oda tins for life." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50637553 +politics Bola Ahmed Tinubu latest news: APC Chieftain no dey hospital for di US """Bola Tinubu no get medical problem wey go need hospitalisation."" Dis na wetin Tunde Rahman, di media aide to Mr Tinubu bin tok afta totori dey for news say di National Leader of di All Progressives Congress (APC) dey hospital for di United States. For statement, Rahman tok say oga Tinubu dey ""hale and hearty"". E follow tok for di statement say ""e dey shameful say pipo wey get hand for dis evil no dey taya afta di fact say evri time dey do dis kain fake news, dem go dey wrong." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58043129 +health Coronavirus update: Landlady remove roof and door from house of tenant wey dey owe rent One Kenyan woman wey fail to pay her rent last month no get front door and roof again inside her house as her landlady vex comot am. Local broadcaster Citizen TV reports say Ruth Shiundu, wey be widow, say she no fit raise 11,000 Kenyan shillings ($102; £84) because di coronavirus pandemic affect her okrika business. Ruth wey get four pikin bin pack enta di house for di capital, Nairobi, last December and she dey always pay her rent for di one-bedroom house without fail. Madam Ruth wey dey sell Okrika bed sheets tell tori pipo say, last Monday, di landlady carry some group of youths go di house and remove di front door with one angle grinder. All di try wey di local administrator for di low-income area of Kawangware try to chook mouth for di mata fall for deaf ears. Den on Tuesday, di landlady come with worker to remove parts of di roof. Madam Ruth wey tears dey for her eyes follow di television station, Citizen TV tok with Swahili language on top wetin happun: https://www.bbc.com/pidgin/tori-52757842 +sports Novak Djokovic beat Roger Federer to win back to back Wimbledon title "Novak Djokovic beat Roger Federer to win back to back Wimbledon title. Djokovic wey be di defending champion gree die beat Federer 7-6 (7-5) 1-6 7-6 (7-4) 4-6 12-12 (7-3) for match wey last over four hours 57 minutes Dis victory mean say di Serbian player don win 16 Grand Slam titles now. Federer mistake wey im hit di ball high give Djokovic victory for di match. ""I go try to forget dis final, but na great match dat na wetin Federer tok afta di match. ""Di match long and i give am everything i bin get my chance and im too get im chance. i happy for my performance, But Novak congratulations, that was crazy. na wetin im add put. Djokovic wey now don win five Wimbledon title say ""Roger na one of di greatest players of all-time, l dey respect well -well na wetin Djokovic tok ""im dey inspires me,.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-48983400 +entertainment Funke Akindele husband JJC Skillz announce say dia marriage don end "Nigerian actress, Funke Akindele’s husband don announce dia separation. For one Instagram post, JJC Skillz say im and Funke don decide to go dia separate ways. “While it lasted we share a lot of things together and don create two beautiful children"" E tok say di last two years don dey extremely difficult for both of dem. JJC Skillz say dia relationship don dey beyond repair now. ""I sabi say I don try my best to fix things but I believe e dey beyond repair now"", e tok. Im add am say three months ago Funke insist say im move out of di house and apart from di popular AMVCA awards im neva dey able to sit down in an 'amicable manner' ""I dey make dis announcement so di public go dey clear say both of dem dey pursue dia separate lives. Funke and JJC Skillz bin marry for 2016 and dia marriage suppose enta six years dis year. Meanwhile, the Jenifer diaries star neva comment on di mata. Abdrasheed Bello, 45,  na Nigerian songwriter, rapper record and television producer. Skillz na producer for one British hip-hop record company and musical group Big Brovaz. Im dey co-produce Industreet one television show about di Nigerian music industry wit wife, Funke Akindele. Before im marriage to Funke Akindele, Bello don be papa to three children from different mama . Im marry Funke for 2016 and for 2018, di couple welcome dia set of twins Funke Akindele dem born her on 24th of August, 1977 insdie Ikorodu, Lagos State. She attend Grace Children Schools, Gbagada and Lagos State Model College, Igbo-kuta. Funke get OND in Mass Communication from Moshood Abiola Polytechnic, Ogun State and a Law degree from the University of Lagos. Funke bin marry Adeola Kehinde Oloyede on May 26, 2012 and they divorce in July 2013 citing irreconcilable differences. She remarry Abdul Resheed Bello, known as JJC Skillz in London in May, 2016. Funke Akindele be Nigerian actress, film producer, scriptwriter, and entrepreneur. She dey popularly known as 'Jenifa', one character she play inside one movie titled Jenifa. Funke Akindele get a special swag for Nigeria entertainment industry. Na sake of how she dey interpret her roles even for her own soap opera 'Jenifa's Dairy'. JJC Skillz announcement dey come just days afta popular Nigerian actress Chacha Eke also announce say her marriage wit long time husband don end. She bin also take to her social media page to say she don tire to dey pretend say ‘all is well’ wit her marriage. “Many pipo don die as dem dey pretend say all is well as dem dey wish, hope and pray for a better tomorrow. “I no wan die or go inexplicably missing.” She write am. Chacha Eke also apologise to her fans ‘for living a lie dis past years’ as tori bin don first comot two years ago say dia relationship bin don dey head to di rocks. ""For di 2nd time for 2years, I dey hia again on social media boldly dey declare say I am done wit my marriage. ""My long overdue/relentless position on dis no be news to Austin Faani - her husband- di doctors and my parents."" Maeanwhile Austin Faani also comot to clarify allegations and suggestions say im bin dey maltreat e wife. ""I neva raise my hand on any woman for my life including my wife,"" Im reaction come plenti hours afta im wife bin announce ontop her Instagram page say dia nine-year-old marriage don end. Di estranged husband of di ogbonge Nollywood actress for im Instagram story on Tuesday night add say ""Everyone wey dey close to dis case sabi di absolute truth and no be my place to divulge am, di one pesin wey start di tok go in due time continue to tok. Make light lead."" E tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4np9e2gy31o +sports Novak Djokovic: I no be anti-vax but I go sacrifice trophies if dem tell me to get di jab "Novak Djokovic don tok say e go rather miss out on future tennis trophies dan dey forced to get di Covid vaccine. E Speak exclusively to BBC wia e say make dem no associate am wit di anti-vax movement, but e support one individual right to choose. Dem ask Djokovic if e fit sacrifice taking part in competitions like Wimbledon and di French Open over im stand on di vaccine. ""Yes, dat na di price I dey willing to pay,"" e tok. Australia deport di 20-times Grand Slam winner last month afta di goment cancel im visa straight sake of im vaccine status. Djokovic, wey be di world number one men tennis player, say e e bin kollect one medical immunity to enta di kontri to play in di Australian Open as e bin recently recover from Covid-19. However, di kontri immigration minister, Alex Hawke, personally cancel di 34-year-old visa, on di ground say im presence fit cause ""civil unrest"" and encourage anti-vaccine sentiment. ""I no ever dey against vaccination,"" e tell di BBC, as e confam say e bin kollect vaccines as pikin, ""but I always support di freedom to choose wetin you put for your body."" For di ogbonge interview, di first since dem detain am for Melbourne for January, Djokovic address tok-tok about di timing of im positive Covid case in December and discuss im own attitude towards di vaccine. Djokovic say e hope say vaccination requirements for certain tournaments fit change, e add say e dey hope say e ""fit play for many more years"". But e also confam say, e dey willing to forget di chance to become statistically di greatest tennis player of all time becos e feel so strongly about di mata. Djokovic rival, Rafael Nadal, don win 21 Grand Slam titles di most for any competitor. Wendem ask am why, e reply say: ""Bicos di principles to make decision on my body dey more important dan any title or anytin else. I dey try to dey in tune wit my body as much as I possibly fit do"" Djokovic say e bin ""always be one great student of wellness, wellbeing, health, nutrition,"" and say im decision dey partly influenced by di positive impact of factors like changing im diet and im sleeping patterns, on im ability as athlete. E say e dey ""keep [im] mind open"" about di possibility say e fit dey vaccinated for future, ""becos we all dey try to find collectively, one best possible solution to end Covid"". ""I no ever dey against vaccination. I understand say globally, everyone dey try to put one big effort to handle dis virus and see say, hopefully, e end soon."" Djokovic be one great pesin if yo tink am. Dem raise am inside two wars for di former Yugoslavia, im parents bin sell di family gold and negotiate wit money lenders to fund im ambitions, e sabi speak six languages wella, you fit argue say e be di greatest player ever to pick up di racket; and e be deeply committed libertarian wey get strong belief of individual freedom. E don clearly tink deep about di conflict between individual freedom and di collective good - and e feel say, as ogbonge sportsman, im body be im business. E say e get open mind, but as tins stand, e no go kollect di jab. E bin also go into further detail about im time wey e spend for detention for Melbourne last month ""I dey really sad and disappointed wit di way e all end for me for Australia,"" e say. ""E no dey easy."" Dem do im medical exemption request anonymously and two independent Australian panels accept am. However, e get one separate travel declaration wey include one error. ""Absolutely, di visa declaration error no dey deliberate,"" Djokovic tok. ""E dey accepted and confamed by di federal court and di minister imself for di Ministry for Immigration in Australia. ""So actually, wetin pipo probably no know be say I no dey deported from Australia sake of say I no dey vaccinated, or say I break any rules or say I make one error for my visa declaration. All of dat dey actually approved and validated by di Federal Court of Australia and di Minister for Immigration. ""Di reason why I dey deported from Australia be bEcos di minister for immigration use im discretion to cancel my visa based on say I fit create some anti-vax sentiment for di kontri or for di city and I completely disagree wit am."" E tok." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60389793 +health How Covid cases for China still dey increase upon tough measures by authorities "China don record dia highest number of daily Covid cases since di pandemic begin, upon strong measures dem design to eliminate di virus. Several major cities including di capital Beijing and southern trade hub Guangzhou dey experience outbreaks. Wednesday witness 31,527 cases wey dem record compare with di April peak of 28,000. Di numbers still dey tiny for kontri of 1.4 billion pipo and officially just over 5,200 pipo don die since di pandemic begin. Dis one equate to three Covid deaths for every million inside China, compared with 3,000 per million for di US and 2,400 per million for UK although direct comparisons between kontries dey difficult. While China zero-Covid policy don really save lives, e don also affect di economy and ordinary pipo lives. Di kontri slightly relax some of those restrictions few weeks ago. China bin cut quarantine for close contacts from seven days for one state facility to five days and three days at home, and also stop to dey record secondary contacts wey allow many more pipo to avoid having to quarantine. Officials don also tink of how dem go avoid enforcing lockdowns like di kind wey di largest city, Shanghai, bin endure early dis year. But as dem dey face new increase for cases inside Beijing, plus di first deaths from di virus in months, officials don already implement some restrictions for several districts, with shops, schools and restaurants wey dey closed. Di central city of Zhengzhou dey also wan enforce one effective lockdown for 6 million residents from Friday, officials announce. Dis na afta violent protests happun for one big industrial complex wey belong to iPhone manufacturer Foxconn. Di company don apologise for one ""technical error"" for dia payment systems. Pipo don also share oda stories of suffering and desperation online. Last week, one report wey say one baby for Zhengzhou die because dem delay her medical care sake of Covid restrictions, lead to ogbonge outcry. Dis na some of di most serious responses to Covid dis year: China na di last major economy wey still dey pursue Covid eradication process with mass testing and lockdown rules, and virus cases wey dem record for 31 provinces. Part of di reason be say vaccination levels dey lower dan in oda developed nations, and only half of di pipo wey dey di age of over 80 get dia primary vaccinations. China don refuse to import vaccines upon evidence say dia homemade jabs neva prove say e dey effective. President Xi Jinping argue say dem need strict controls to protect di kontri large elderly population." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c87eged8gggo +health Coronavirus: Fake news wey don spread about Covid-19 for Africa "As di case of coronavirus continue to increase all ova di world, na so plenty confusing and fake news too dey show face. Although confam case of di virus neva plenty for Africa, authorities for some kontris still dey struggle wit wrong informate. Pipo dey read wrong meaning to one old pishure wey US health authorities do about bear-bear and respirators, dem begin reason say di foto say make men shave dia bear-bear so dem no go catch coronavirus. Nigeria Punch newspaper headline say: ""To dey safe from coronavirus, shave your bear-bear, CDC warn."" We don add labels to di screenshoot to show weda di tori na lie or dem use old foto. Di US Centre for Disease Control (CDC) foto show plenty examples of bear-bear and which ones to avoid wen you wear gas mask. Dem approve bear-bear style like Side Whiskers and Zappa but styles like Garibaldi and French Fork fit no work well wit di gas mask and e fit no make am work well. Di foto dey authentic - but na for 2017 dem create am (long before coronavirus outbreak) for workers wey like to wear tight gas mask. Unlike wetin di news report, dis na old tori and e no say make pipo shave dia bear-bear. Similar headlines don appear for oda kontris wey many pipo don share. One Australia media 7News post for twitter: ""How your beard fit increase your risk of Coronavirus."" Current UK health advice tok say while masks dey useful for medical staff for hospitals, ""little evidence na im dey if e get benefit for members of di public"". One evangelical preacher wey dey claim say im fit cure di virus, na anoda subject of disinformation. Tori about David Kingleo Elijah, from di Glorious Mount of Possibility Church begin dey spread online after one video show for Youtube wia e tok say im dey go China to ""destroy"" di virus and dem share am for oda platforms. Few days later, reports show for different blogs dey allege say di pastor don travel go China and dem don admit am for hospital afta e contact di virus. Di blogs bin use anoda name for di pastor - Elija Emeka Chibuike. Di foto wey dey use show di man for di hospital, na di foto of Adeshina Adesanya, one popular Nigerian actor wey pipo know as Pastor Ajidara, wey die inside hospital for 2017. Di tori about di Nigerian driver wey dem diagnose for coronavirus come post for social media, see many Whatsapp users share am - but di tori na lie. According to di message, the taxi driver bin drive di ""white man"" wey dem diagnose wit coronavirus go one isolation centre location. Di Ogun state government come tell di driver say make e go hospital. Di tori be say d driver test positive for coronavirus - im escape from hospital come dey spit fire say im go spread di virus unless dey pay im family 100m naira ($274,000). Authorities don deny dis report. Di Ogun State government inside statement tok say no patient escape from di isolation centre. Di original post appear for di fake account of one private station Africa Independent Television (AIT) network, and dem release statement say di page no be dia official Facebook page. Di post include di foto of di driver and dem name am Adewale Isaac Olorogun. However, di same foto bin appear for one Buzzfeed article about Libya wit anoda different name - Jude Ikuenobe. Mr Ikuenobe wey follow BBC Yemisi Adegoke tok say di mata shock am wen im hear say im name dey trend for one post. E tok say di mata tire am as some of di comments contain violent threats against am. And since di post go viral, im no dey find am easy to cope. Nigeria and sub-Saharan Africa first confam Coronavirus case na one Italian man wey fly enta Lagos on 25 February. Authorities say dem don reach out to like 100 pipo wey fit don come in contact with di man. For Kenya, di goment don put out statement say one audio recording wey dey circulate for Watsapp wey claim say na official press briefing on di virus outbreak na ""fake news"". Di recording say 63 pipo for di kontri don catch di virus, wey no be true. Kenya no get any confam case of coronavirus. Di health ministry say na part of communications training exercise but dem no explain how e take leak to di public. For Kenya law dey say any Kenyan wey publish or share fake news about outbreak of di virus go get fine of $50,000 (£39,000) or get two-year jail sentence. For Nigeria, one preacher post one video and one pesin wey post am claim say pepper soup dey cure coronavirus. Di claim also dey WhatsApp. No cure or any treatment don dey for coronavirus. For Cape Verde, di tiny Portuguese-speaking West African nation, one post bin spread for social media claim say one Brazilian doctor don recommend fennel tea as cure for coronavirus. Dis tori make pipo rush go buy di herb for local market, according to AFP report. Di Brazilian health ministry don sama warning give pipo make dem no share any article give pipo wey dey suggest fennel as cure for coronavirus. Di World Health Organization say thorough and regular hand-washing dey very important for di fight to avoid infection." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51764759 +politics Ghana New Patriotic Party [NPP] political communicator, Asare Kofi Israel chop 40 strong lashes after he insult Drobo Queen Mother Ghana New Patriotic Party [NPP] political communicator, Asare Kofi Israel enter hot soup after traditional authority give am 40 lashes for insulting de Queen Mother of Drobo. E no clear exactly de insults he use but local reports reveal say de young man use some harsh and violent words on de queen mother, Nana Yaa Ansuaa. De Traditional Council sake of dis sentence de New Patriotic Party communicator to 40 lashes sake of dem want instil discipline in de in de young man. Pictures of de young man which go viral after he collect de lashes dey show cane marks on en body, he dey look like he dey inside pain wey people dey help am move around. After de lashes, de traditional authorities warn Asare say he for show good behaviour or dem go remove am from de Jaman South Municipality, Bono Region. Politicians and communicators dey use abusive language on each other, dis be one of de first few cases where politician chop punishment sake of dis time dem attack traditional leader. https://www.bbc.com/pidgin/world-55313144 +health Ghana: To cook meat, beans wit paracetamol na death be dat - Health authority Local health authorities for Ghana don sama warning give food sellers for di kontri wey dey use paracetamol to cook meat and beans make dem stop, say e dey dangerous. One health worker for di Wassa Akropong Government Hospital, Obed Sefah Boakye say wen dem use di drug for cooking, e go turn into anoda tin wey no be pain killer and e fit be poison. Im explain say di poisonous chemical wey e turn to, fit cause kidney failure, liver failure, pancreatitis, lactic acidosis plus plenti oda orishirishi sickness. According to Ghana News Agency, some food sellers for di kontri dey use paracetamol to cook meat and beans to make am soft sharply. Oga Sefah draw ear give kontri pipo make dem dey careful wia dem from dey buy food. https://www.bbc.com/pidgin/50444152 +politics Emeka Ihedioha: 'Everybody know say na me win di 2019 Imo election' For di first time wey im go open mouth tok to tori pipo afta di surprise Supreme Court Judgment wey sack am as Imo State govnor and bring in Hope Uzodinma, Emeka Ihedioha tok to BBC Igbo for dis exclusive interview. Oga Ihedioha tok how e react wen im hear di news and im next line of action. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51391521 +sports Hana Kimura: Japanese professional wrestler and Netflix star die at 22 "Hana Kimura, professional wrestler wey appear for Netflix reality show Terrace House don die for di age of 22. Stardom wrestling, wey be Kimura organisation confam di news and come ask fans to dey respectful. E no dey clear about wetin kill her. Just before she die, she put out different social media posts wey hint say pipo dey cyber-bully her - dis one mean say dem fit don abuse or troll her for social media. Di most recent update for her Instagram story on Friday feature one foto of her wit her cat, wit caption wia she tok ""goodbye"". Kimura na winner of Stardom 2019 Fighting Spirit Award, and she bin follow dey for di reality TV show Terrace House, before dem suspend di show sake of coronavirus. Her mother also be popular wrestler, Kyoto Kimura. Stardom wey confam her death for Twitter say: ""Abeg make una dey respectful and allow some tome for tins to process, and keep your thoughts and prayers wit her family and friends."" Concerns bin come up on Friday after Kimura post images of self-harm for Twitter along wit di message: ""I no wan be human again. I bin want make pipo love me for dis life. Thank you everyone, I love you. Bye."" Kimura bin be di target of many tweets from fans wey dey one kind and face critics on daily basis. As news comot say she don die, fans and industry pipo begin speak out against cyber-bullying and di impact wey e get on mental health. ""E absolutely break my break how pipo fit dey wicked on social media,"" na so Impact World Champion Tessa Blanchard tok. ""Na amazing honour to know Hana Kimura. She be di most amazing girl wit kind soul and serious passion and work ethic."" ""I hope dis go serve as reminder say wetin pipo dey tok for social media fit get serious effect on mental health of anyone, no matter who dem be,"" na so Wrestling journalist Adam Pacitti tok, Fans and professional wrestlers don begin send sorry message of how dem go iss Hana Kimura and how ""heart broken"" dem dey." https://www.bbc.com/pidgin/sport-52788192 +business Ghana traders start dey cry foul afta Nigeria close dema border sake of smuggled contraband goods "Ghana Foreign Affairs Ministry say Nigeria decision to close de Naija-Benin border dey affect traders for Ghana who say dema goods lock up. Minister of Foreign Affairs, Shirley Ayorkor Botchwey, say de reason why Naija close dema border be sake of de smuggling of contraband goods which dey affect Nigerian business people. Despite say Nigeria complain chaw times give Benin authorities, de contraband goods still dey enter Naija sake of dat dem close de Igolor den Seme-Krake (Nigeria-Benin) borders. De decision by Nigeria dey affect Ghanaian traders who export non-traditional products enter Nigeria. Ghana Union of Traders Association (GUTA) President, Joseph Obeng, say de border wey Nigeria close be outright breach of ECOWAS treaties. ""De Ministry talk plus ETLS Task Force, Ghana authorities, ELTS exporters for Ghana den Nigerian authorities on de matter so say dem go follow de relevant ECOWAS protocols on regional trade "" Shirley Ayorkor Botchwey talk for statement wey she sign inside. She say she plead plus Nigeria say sake of de good relationship wey dey between Ghana den Naija, dem for see how dem fit sort dis matter. Two months now since Nigeria close dema border sake of goods wey people dey smuggle enter dema country, but check like de decision dey bite Ghana hard. Nigeria President Muhammadu Buhari say di reason for di partial closing of Nigeria border with Benin Republic na sake of di massive smuggling activities, especially of rice, wey dey happun for dia. President Buhari, wey express great concern ova di smuggling of rice, say e dey threaten wetin e administration done achieve with dia agricultural policies. According to am, ""Now wey our people for di rural areas dem dey go back to dia farms, and di kontri don save money wey dem for spend to dey import rice with di kontri scarce foreign reserves, we no fit allow smuggling of di product on large scale like dat to continue."" The Nigerian President say di limited closure of di kontri western border na to allow Nigeria security forces develop strategy on how to fight di smuggling." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50078717 +entertainment Meet di 13-year old gele and make-up expert Fatai begin practice how to tie gele with im younger sister, but now im don dey make money from am. Im most recent customer na popular Nollywood actress Adunni Ade. Di 13-year-old still dey school, but im get big plans for im talent. Producer: Olubunmi Okunnu https://www.bbc.com/pidgin/media-41544733 +entertainment Alexx Ekubo break up: Fancy Acholonu confam end of relationship wit Nollywood actor, call off wedding "Fancy Acholonu don confam di end of her relationship and engagement with Nigerian actor, Alexx Ekubo. She reveal dis one for inside her Instagram page say she don end di relationship, engagement and don call off di wedding with di Nolly wood star. She tok for di statement say ""she make di best decision for me because e dey very important say make everybodi find happiness and live for dia truth"". Dis na as rumours bin spread for inside social media say dia relationship packup. Dis na as social media investigators notice say di couple no dey follow each oda again. Alexx neva tok anytin ontop di mata and Fancy pictures and dia engagement, everitin still dey for im Instagram. Howeva dem don deactivate dia couple account wey dem call ""Falexxforever"". Di couple bin announce dia engagement for May, 2021 and dem suppose marry for November dis year. Social media pipo don begin chook mouth for inside di mata, dem even dey guess wetin cause breakup. Pesin tok say na because dem carry dia relationship enta social media, na im make ""two seconds everything don scata"". While oda pipo say dia break up pain dem, odas dey happy say Alexx don enta back inside market as single guy." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58350442 +politics BBC Pidgin Edo Governorship Election Debate: Osagie Ize-Iyamu, Godwin Obaseki, Jones Osagiobare lock horns ahead of 19 September Edo vote "By 9pm Friday 4 September, 2020, three candidates wey dey eye di number one position for Edo State jam face to face ontop BBC News Pidgin Governorship Debate to argue why dem wan govern di southern Nigerian state. Di pipo of Edo State go vote on 19 September, 2020 for govnorship election wey go decide who go lead dem for anoda four years. Govnor Godwin Obaseki of Peoples Democratic Party, Pastor Osagie Ize-Iyamu of All Progressives Congress and Jones Osagiobare of Young Progressives Party na im show for di BBC Pidgin Facebook Live Debate wey last for ova ninety minutes. Nigeria election office - Independent National Electoral Commission, don already clear di three candidates wey appear for di debate to contest di Edo govnorship election. Different segments dey di debate; section wia di candidates give dia manifesto dey. Candidates tok wetin dem go do differently if dem win. Di host, Helen Oyibo, wey be BBC Pidgin senior journalist, also ask dem kwesions on top some problems wey dey di state and issues wey dey affect citizens. Click here to watch di Live BBC Pidgin Edo Governorship Debate 2020 on Friday. Di govnorship candidates of Edo State election gather to tell dia pipo wetin dem go do if dem win election for di debate wey BBC pidgin organise. Di debate happun for BBC social media platfoms on Friday where di candidates table dia plans. Di candidate of d All Progressive Congress (APC), Osagie Ize-Iyamu, say im get plan wey im don tag 'simple' agenda. He say di SIMPLE wey be short for -Security, infrastructure, man power training, public-private partnership, leadership by example, employment- na area wey im wan focus on if dem elect am to be di state governor. Godwin Obaseki di current govnor and di candidate of Peoples Democratic Party (PDP) tok thru im deputy and list di tins wey dem don do for dia current goment. He add say dem go continue. Later di organiser tell di candidate say only di govnor go fit continue wen Obasaki take excuse to comot di show. He later come back before di debate end. For di candidate of di Young Proressive Party (YPP), Jones Osagiobare, im say im go do partnership with some America company to help mechanise agriculture for di state. ""We wan enter partnership with some America farm to do full agriculture of di state. We wan make agriculture mechanise farming. We go also tackle future unemployment,"" he tok. Wen di presenter bin ask dem wetin dem go do to fight human trafficking and migration wey popular for di state, YPP and PDP candidates say dem go create more jobs. ""If job dey pipo no go leave go abroad. We go create job for our youth. We no put teachers for our school. If di house dey comfortable, pipo go dey, APC candidate Ize-Iyamu tok. ""We wan build technology village. If we need bring in China to teach our pipo, we go do am to generate revenue and make sure say our reserve dey beta. We go diversity around agriculture and technology. We go also take care of old pipo"" na wetin di YPP candidate tok about how im go diversity economy. Di candidates condemn election thugs and encourage dia supporter not to fight or tiff ballot box. ""Thugggery na part of di culture wey I meet. Di pipo wey dey cause fight no get anything to lose. If di thuggery continue, na me e go affect and we dey do anything to ensure say we stop am. I don warn my pipo say if dem attack dem, make dem go report to police, Obaseki say." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54026595 +entertainment Milk crates challenge: Wetin be dis crate challenge wey don go viral? - See explanation "'Milk crate challenge' don begin go viral for social media all ova di world. Di ""Milk Crate Challenge"" first start for TikTok and now e don dey enta oda social platforms like Twitter and Instagram. Experts for America wia di challenge don sama warning say dis new trend wey dey unsafe. Di overcrowding of U.S. emergency rooms sake of di COVID-19 make dem cut di warning. Dem say dis na disaster wey dey wait to happen. For Nigeria, concern citizens don begin dey sama warning give pipo wey dey plan to join di challenge. As at 24 August resident doctors for di kontri dey on strike and health insurance no dey for everi-one. Di challenge wey start for United State of America involve climbing up empty milk crates. Dem dey arrange creates on top each oda like staircase but e dey dangerous because di participant fit fall. Di arrangement of di milk crate go dey like pyramid and di participant need to successfully waka. Di challenger gatz move from di beginning of one side go reach down of di oda side before dem go win either money prize. Videos of pipo both young and old wey dey partake for dis challenge don full everywhere for social media. Even funny memes of pipo wey fall or not dey successful to complete di challenge dey trend for internet. So far for dis new challenge only few pipo don manage to truly climb to di top. Also few na im don complete di pile of empty milk crate wey form di pyramid or staircase. Some pesin wey don master di act to climb di pyramid dey even use high heels waka through di crate. Some deY use bicycle take clime sef. But as di trend dey go viral, a lot of pipo dey concern about di injury wey di stunt fit lead to. And some of which be breaking of back, legs arms and odas serious injuries. According to Know Your Meme, di milk crate challenge begin over one week ago. Dat na wen one video wey dem post on 13th August show some pipo inside one park dey try di challenge. Pipo share di video on Facebook and soon e go viral. E come later enta TikTok and di trend begin." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58318072 +entertainment BBNaija Lockdown Reunion: Highlights of Monday episode of 'BBNaija reunion 2021' on Tolanibaj/Prince & Vee "Fans of di popular reality television show for Nigeria, Big Brother Naija still dey tok about di relationships of housemates Di situationship between Ozo, Nengi and Dorathy during di Friday episode of BBNaija Lockdown Reunion still dey fans mouth. For di show di host Ebuka Obi-Uchendu bin torchlight di stories wey surround Nengi, Ozo, Dorathy and Prince situationship inside di house. But di main highlight wey shock fans na di gbas -gbos wey happun between Dorathy and Wathoni. Dora bin dey address di situationship between herself Nengi and Ozo wit di host Ebuka. Di exchange of words occur her revelation say she bin like Prince not Ozo inside di house. Di two ladies bin clash wen Wathoni chook mouth as Dora bin dey address di mata wit Ebuka. Dis na di first time wey di Lockdown gang dey come togeda for inside di same place since di show end almost a year ago. Di reunion na to clear di air and tok dia church mind towards each oda. And also revisit some of di highlights and memorable moments from Season 5 edition wey Laycon emerge as a winner. From di short teaser at di end of Friday episode Ebuka still focus on di relationship mata inside di house for Monday episode. Dis time na Prince and Tolanibaj relationship, wetin happun and how tins be now. Tbaj bin address Prince inside di short video clip wey dem show, Earlier Tbaj say she come di reunion to ""come speak her truth not to change di narrative. But she explain di narrative wey some pipo don attach to di Tolanibaj name."" She also mention say she go confront di pipo wey she need confront. For anoda clip wey di organizers Tolanibaj clsh wit Vee. For inside di video, Baj say she go 'smack' Vee. Fans go get to find out for demsefs, wetin dey cause dis gbas-gbos. Na cable company DSTV dey show di ""BBNaija Lockdown Reunion"" for African magic Urban at 10:00pm. And at 10:30pm on AM Family from Mondays -Fridays. Organisers say di four things to expect from di Lockdown Reunion na For di first time for di Big Brother Naija Reunion history, every single Housemate for di Lockdown Season go attend. E get more love triangles and squares than wetin pipo fit imagine According to Big Brother, di biggest clash come from two supposed friends and di first reconciliation come from two longtime enemies. Di show host, Ebuka mention say e get more than one few jaw dropping moments. And even di Housemates dey shocked to find out how much dem no really sabi each oda, Ebuka add. BBNaija Reunion Show na part of preparations for di commencement of another season of di reality show. And fans go once again get to see dia favourite 'Lockdown geng'." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57551048 +politics Ministerial list: Seven women make Buhari list Nigeria President Muhammadu Buhari send di list of 42 ministerial nominees go Senate for confirmation on Wednesday. Inside di list, na only seven women make am. While some pipo dey hail di seven women wey make am to di list, odas dey complain say di number of women no follow at all. Dis women of timber and calibre wey make am to di Ministerial list don hold different ogbonge position for Finance, governance, civil service, di United Nations Education Scientific and Cultural Organisation (UNESCO) and odas. Dem also get ogbonge degrees from different field of study. Zainab Ahmed na di former Minister of Finance wey President Buhari appoint for September 2018 afta di oga madam wey dey dia before, Kemi Adeosun resign. Madam Zainab get Bachelor of Science degree in accounting from ABU Zaria and Master in Business Administration (MBA). Her twitter profile say she get ova 28 years of experience in accounting and public finance management. Sharon Ikeazor na di Executive Secretary of Pension Transitional Arrangement Directorate (PTAD) wey President Buhari appoint on the September 26, 2016. Report say for first year inside office, she make plenti policies wey bring beta changes to di PTAD. She get Bachelor of Law (LL.B Hons.) from di University of Benin and Certificate of Practice from Nigerian Law School for 1985. Her twitter profile say she dey passionate about better Nigeria and better opportunities for women. Sadiya Farouq na di federal Commissioner of National Commission for Refugees, Migrants and Internally Displaced Persons. She get Bsc. in Business Administration from Ahmadu Bello University Zaria, Kaduna State and Master degree in International Affairs and Diplomacy plus also Masters in Business Administration (MBA) from Ahmadu Bello University. Maryam Yalwaji Katagum na Ambassador, Permanent Delegate of Nigeria to UNESCO wey dem appoint for June 2009. She get Masters in Administration and Planning from University of Lagos, Bachelor of Arts (B.A.) in English, Graduate Certificate in Education from Ahmadu Bello University, and Certificate in Social Development Policy, Planning and Practice from University College, London. Gbemi Saraki na former Senator wey dem elect to represent Kwara central Senatorial district and she be also di sister of former Senate president, Bukola Saraki. She attend University of Sussex for United Kingdom and get bachelor degree in Economics. Ramatu Tijani na di former All Progressive Congress (APC) National woman Leader. For one interview wey she do wit di nation newspaper for 2018, she say she attend Ahmadu Bello University Zaria, wia she for get degree in Urban and Regional Planning. She get master degree in Public Administration. As at then, she add say she dey currently do her Ph.D in Security and Strategic Studies from di same institution. Pauline Tallen na Former deputy governor of Plateau State for 2007 and di first woman to be deputy governor for northern Nigeria. For 1999, she become di Minister of State for science and technology during di time of former president, Olusegun Obasanjo. She also don contest to be governor of plateau state for 2011, but lost to Jonah Jang. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49094164 +sports Papa Bouba Diop death: Senegalese first goal scorer for 2002 World Cup Papa Diop don die "Papa Bouba Diop, former Senegalese International, don die at de age of 41 years. Senegalese first goal scorer for 2002 Word Cup Diop die pn Sunday afta long sickness. De Teranga Lion Diop bin play with Racing Club of Lens for France for 2001/2002. Racing club confirm Papa Bouba Diop death on Sunday evening of 29 November 2020. Di club tweet Diop death; ""Na wit deep sadness weh Racing Club of Lens learn say former player, Papa Bouba Diop don die at de age of 42. We present sincere condolences for his family, de club tweet."" World Football governing join bodi Fifa and Lassana Camara, consultant for Radio France International also confam Papa Bouba Diop death." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55125031 +sports Christine Mboma win BBC African Sports Personality of the Year "Namibian sprinter Christine Mboma don win di BBC African Sports Personality of di Year award. She be di first female to win di award since di award bin start. Mboma dey voted as winner from a list of six nominees wey include Kenyan athletes Eliud Kipchoge and Faith Kipyegon, Senegalese goalkeeper Edouard Mendy, South African Paralympic star Ntando Mahlangu and South African, swimmer Tatjana Schoenmaker. Di 18-year-old become di first Namibian woman to ever win Olympic medal when she collect silver for 200m final for Tokyo last year. She tell BBC Sport Africa say ""I feel great and really proud to be a Namibian,"". ""I dedicate dis BBC award to all Namibians. Dis na reward for all di hard work I do."" She be di second Namibian athlete to win di ogbonge award afta sprinter Frankie Fredericks win di BBC African Sports Star of di Year award in 1993. Plus her Olympic silver, Mboma also na Diamond League champion and Under-20 gold medallist over 200m, she break di Under-20 record over di distance several times last year. Mboma say her achievement go motivate young athletes from Africa. Di sprinter get rough childhood. When she be 13, her disabled mama die as she dey give birth. She leave Mboma to look afta her two younger siblings. Di poverty she experience wen she dey grow make her dey sleep for bed wey no get mattress for inside one room she share wit her grandmother, until she enta athletics.Namibian sprinter Christine Mboma don win di BBC African Sports Personality of di Year award." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59915942 +politics Ekiti State don officially swear in Biodun Oyebanji as Governor Abiodun Oyebanji, don take im oath of office as di Ekiti State Governor. Na di Chief Judge of Ekiti State, Hon. Justice Oyewole Adeyeye swear am im at about 12: 53pm as pipo gada for di event on Sunday, October 16. Govnor Abiodun pledge to preserve, protect and defend plus preserve di office as di number one citizen of di state. “Today mark di beginning of a new dawn for Ekiti, and I dey more than proud to serve di good people of our dear state.”, e tok. Inec bin declare di APC candidate, winner of di Ekiti govnorship election wey happun on Saturday, 18, June, 2022. Biodun Oyebanji win 15 out of 16 local goment areas for di state. “As I assume di office today, na to actualise di prosperity of Ekiti pipo.” Govnor Oyebanji tok. E say im vision na for Ekiti State to become a land of prosperity, opportunity, peace and progress. “Di land wia transformed pipo and communities fit reap di fruits of dia labour in dignity, good health and safety. “Land of honour wia integrity mata.” Part of im promises na say im go make sure to give priority to gender mainstreaming and women empowerment for all policies and programs. E also say im go create employment and income-generating opportunities for di pipo of Ekiti, make sure say children fit access free and qualitative basic education up to Senior Secondary School 3 “Dis task go be di toughest of my life but e say wit di pipo on im side im go fit achieve am.”, e add am. Biodun Abayomi Oyebanji na public servant wey be 55 years old Oyebanji come from Ikogosi-Ekiti for Ekiti State. Im don serve as Special Assistant (Parliament Affairs) to di Governor of Ekiti State from 8th June 1999-2000 and August 1, 2000 to September 2001. Im also serve as Chief of Staff to Governor of Ekiti State between September 2001 to May 29, 2003. Oyebanji work as Commissioner, Ministry of Budget, Economic Planning and Service Delivery, Ekiti State from January 10, 2013 to October 16 2014, and also Secretary, Ekiti State Goment 16th October 2018 till December 7, 2021. Di Ekiti state born politician don tey for politics. E join public service for im 20's as di secretary to di committee wey dem set up for di creation of Ekiti state for 1994. Oyebanji na former university lecturer before e join politics. E bin serve as special assistant on legislative matters to di first governor of Ekiti State, Otunba Adeniyi Adebayo, before e later become im Chief of Staff. For di first term of di current governor, Kayode Fayemi, Oyebanji serve as di director-general, Office of Transformation, Strategy and Delivery; Commissioner of Integration and Inter-governmental Relations; and Fayemi later appoint am as Commissioner of Budget and Economic Planning. E don hold oda political offices for di state and e resign as di secretary to di state goment on December 7, 2021 to join di govnorship race. Dem born di APC governorship candidate for December 21, 1967. E get Bachelor of Science (BSc.) degree in Political Science from di Ondo State University (now Ekiti State University, Ado-Ekiti) for 1989. Masters' Degree in Political Science (International Relations & Strategic Studies) for di University of Ibadan. Oyebanji dey married to Prof. (Mrs) Oyebanji, wey be associate professor for di University of Ibadan. Otunba Niyi Adebayo  na di first elected Civilian Governor for di state. Im rule between 29 May, 1999 – 29 May, 2003 under di Alliance for Democracy party (AD). Ayo Fayose become di next govnor between 29 May, 2003 – 19 October, 2006 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) to become di second elected civilian govnor of di State. Di state assembly later impeach Fayose on October 16 afta e chop accuse of money mago-mago say e embezzle funds, dem later replace am wit di state Speaker Aderemi but federal goment declare say di move dey illegal. General Tunji Olurin (Rtd) become di state administrator from 19 October, 2006 – 27 April, 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) afta dem declare state of emergency for di State. Chief Tope Ademiluyi  become Acting Governor for 27 April, 2007 – 29 May 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) Engr Segun Oni become Governor for 29 May, 2007 and rule till 17 Feb, 2009 under di flagship of di Peoples’ Democratic Party (PDP) before Appeal court remove am based on illegal returns of April 2007 elections. INEC later organise a partial re-run of di election. Rt. Hon. Tunji Odeyemi step in as acting govnor between dis period from 17 February, 2009 – 6 May, 2009 di under Peoples’ Democratic Party (PDP). Im become acting govnor wen one appeal court wey sit for Ilorin, Kwara State nullify Segun Oni election and order rerun poll inside 10 out of di 16 local councils wey dey di State. Dr. John Kayode Fayemi become govnor of di state for 16 Oct, 2010 – 16 Oct, 2014 under di All Progressive Congress (APC) Mr. Ayodele Fayose become govnor of di state for di second time for 16 Oct, 2014 – 16 Oct, 2018 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) Dr John Kayode Fayemi win Ekiti State election again for 15 July, 2018 to lead di state and im tenure end for October 2022. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw0qq78v82ro +politics """Ondo State election results 2020"" na Akeredolu win" Ondo residents dey vote to decide who go be dia next govnor. Candidate wey win di Saturday October 10, 2020 vote go tanda as govnor of Ondo State for south west Nigeria till 2024. Just click on di map of each of di 18 local goments to see di party wey dey win and how pipo dey vote. Our eye dey dis tori and we go dey update am as we get di results dem. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54485611 +health Coronavirus update: Africa no go be testing ground for vaccine - WHO don tok "Di oga World Health Organization (WHO) don condemned two French doctors wey tok say make dem test di vaccine for the coronavirus for Africa. Di join-bodi organisation of health workers don call di comment of di two doctors ""racist"". ""Africa no fit be testing ground for any vaccine, WHO Director General Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus tok. Di doctors' tok during one TV debate and dia tok make pipo vex say dem wan turn Africa to ""human guinea pigs"". One of dem don tok sorry. When dem ask oga Tedros im reaction for di doctors tok during one briefing wey WHO organise, di oga con angry say di tok na hangover from ""colonial mentality"". ""Na disgrace, appalling, to hear for dis 21st century from scientists, to dey tok dis kain tok. We condemn dis in di strongest words possible, and we assure you say e no go happun,"" he tok. As di number of conmfam cases for Africa continue to dey go up. Some goment dey impose strict measures to take slow di spread of di virus. Nigeria President Muhamadu Buhari don ban all travel in and out of di kontri and three oda major towns for two weeks since March 30. During one debate ontop French TV channel LCI, Camille Locht, wey be head of research for Inserm health research group, tok about vaccine trial for Europe and Australia. Jean-Paul Mira, wey be head of intensive care for Cochin hospital for Paris, con say: ""If I fit be provocative, shey we no suppose dey do dis study for Africa where dem no get mask, treatment or even resuscitation? ""sometin like dia happen somewhere for study aids. For prostitutes, we try am sake of say we know say dem dey highly exposed dem no dey use protection."" Mr Locht nod say im agree wit di suggestion, and im say: You dey correct. We dey process to dey tink about same study for Africa. Dr Mira don earlier ask whether di study go work on healthcare workers for Australia and Europe sake of dem get access to personal protective equipment (PPE) when dem dey work. Di show spark plenty, even from former footballer Didier Drogba, wey call di comments ""deeply racist"". He add: ""No take African pipo as human guinea pigs! E dey absolutely disgusting"". Im fellow former footballer Samuel Eto'o call the doctors ""murderers"". Di doctors' comments don also fuel existing fears for Africa say African pipo go be guinea pigs for di new coronavirus vaccine. Coronavirus centres dey targeted for African countries - most recently, one facility wey dey under construction for Abidjan, Ivory Coast suffer attack from protesters. Video wey dem post for aocial media show pipo wey dey tear di centre down wit dia hands, and dey smash contruction materials for ground." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52202115 +health Covid-19: UK begin £10,000 fine, see oda kontris wia rules breaking go cost you "On Monday, UK go begin nack fine up to £10,000 ($12,700) ontop anybodi wey refuse to self-isolate. But no be only dem get fines for Covid-19 rules breaking. As kontris around di world dey try find way to reduce di Covid-19, e don become necessary for goment to bring serious measures to make citizens comply wit safety rules and guidelines. Make we torchlight some kontris wey get 'Covid-19' fines from di small to di big money. Earlier in September, Rwanda announce say for di capital Kigali pesin wey no wear im face mask well-well go pay $10 fine. Di same amount valid for pesin wey break social distancing rules for public, or disobey night-time curfew. But, di money rise shaparly fo $200 for organisers of parties and oda illegal gatherings; and those wey attend go need find $25. Although di West Africa kontri no get fixed amount to use fine pipo, di court fit nack fine ontop anyone wey break safety rules. One popular case na that of Nollywood actress Funke Akindele and her husband Rasheed ""JJC Skillz"" Bello, wey chop 100 thousand naira fine each (wey pass $250USD) because dem organise house party during lockdown. For South Africa, you need to think twice before you go lie onto pesin head say e get Covid-19, because na offence wey attract R3000 ($175) fine. And R5000 fine dey wait anybodi wey expose im fellow citizen to di virus on purpose. Even if pesin dey inside vehicle but e no wear mask for Delhi, India, na Rs 500 ($7) on-the-spot fine di pesin go pay. Say you wan go find di money no dey di tori at all. Di minimum fine for pesin wey no gree do stay-at-home na 601 euros ($700), and di punishment fit increase in line wit how di offence serious. For instance, if pesin go hold party during lockdown, di fine fit reach 10,400 euros. For April, one man for Logroño, La Rioja region chop fine from police because e carri ""im goldfish for stroll"". Many kontris dey learn work wia Saudi Arabia dey - as far as fines dey concerned. As at May 2020, break quarantine rules for Saudi Arabia and you fit pay reach 200,000 riyals (over $53,000) or face prison for two years, according to online reports. Although, by September e be like say e don drop to 10,000 riyal ($2,600)." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54330659 +politics Osinbajo: Nigeria vice president ready to face Tinubu, Amaechi, Wike, Atiku, Obi plus odas for 2023 Presidential Election? "No be tori again say Nigeria Vice-President Yemi Osinbajo wan contest for di 2023 presidential election. E wan take over from im oga, president Muhammadu Buhari. Di vice-president declare im intention to run for di next kontri president on Monday morning through one video wey e release for media. ""Today, wit utmost humility I formally declare my intention to run for di office of di President of di Federal Republic of Nigeria on di platform of APC,"" na im tok for di video. Plenty politicians don declare dia intention to contest di 2023 presidential elections across di two main political parties for Nigeria wey be - All Progressives Congress (APC) and Peoples Democratic Party (PDP). Dis na as president Buhari tenure dey end for June, 2023. Though di ruling APC don zone dia presidential position to south, PDP neva decide on wia to zone dia ticket. Some of those wey don already indicate interest for APC na former Abia state govnor Orji Uzor Kalu, former Imo govnor Rochas Okorocha, Ebonyi state govnor Dave Umahi, former Lagos governor Bola Tinubu and current Minister of Transportation Rotimi Amaechi. For PDP na former senate president Pius Anyim, former Vice president Atiku Abubakar, former senate president Bukola Saraki, former Anambra govnor Peter Obi as well as Nyesom Wike, Aminu Tambuwal and Bala Mohammed wey be govnors of Rivers, Sokoto, and Bauchi states. Oda aspirants dey also contest for di presidential position for oda political party. All di pipo wey dey contest na big name. But how big dem dey? Whether Vice President Osinbajo go fit beat dis pipo na anoda question. Tori say Nigeria vice-president go contest election for presidency bin dey come out small-small but e no clear until today. Among all di aspirants so far na only two pipo don reach Vice-President level. Apart from Atiku Abubakar wey don work as Vice President before for 1999 - 2007, none of di aspirants don reach dat level. Na only im and Osinbajo. For any aspirant to to win e must first become candidate of dia political party through primary election. Na so di electoral body - di Independent National Electoral Commission (Inec) tok. Na afta party primary di candidates go emerge before Nigerians go get chance to decide who dem wan vote for. Dia fore, Vice President Yemi Osinbajo don declare but if im go fit win di ticket of im party APC na anoda tin. Di pipo to beat for di ticket strong especially im former oga Bola Tinubu and di minister of Transportation Rotimi Amaechi. Inec don release guidelines for di 2023 general elections and mandate all political party to don choose dia candidate by June dis year. Yemi Osinbajo na Nigerian lawyer, professor, and politician wey be di 14th and current Vice President of Nigeria since 2015 under di All Progressives Congress (APC). Im bin previously serve as Attorney General of Lagos State from 1999 to 2007 and hold di title of Senior Advocate of Nigeria (SAN). For 1999, Osinbajo gbab appointment as Attorney-General and Commissioner for Justice for di cabinet of Lagos State Govnor Bola Tinubu. Afta e serve during both of Tinubu four-year terms, Osinbajo comot government for 2007 and return to law. E follow dey do lecturing plus preaching for di Redeemed Christian Church of God. Before di 2015 presidential election, dem chose Osinbajo as running mate to APC nominee Muhammadu Buhari. Na dia ticket defeat di den-incumbent President Goodluck Jonathan and Vice President Namadi Sambo. Four years later, im win re-election. Osinbajo tenure dey marked wit rising profile, especially wen im take power as Acting President wen president Buhari travel abroad." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61073550 +sports Scotland vs Czech Republic: Patrik Schick score wonder goal for Czech to send dem top of group D ahead of England Czech Republic flog Scotland 2-0 for dia opening group match for Euro 2020 to send dem top of group D ahead of England. Na Patrik Schick score di two goals for Czech for inside Hampden Park for Glasgow to give di visitors victory. Di first goal of di match na from set piece, wey Scotland bin dey slow to react afta Grant Hanley head ball from corner clear but dem fail to deal wit di second cross from Czech wey Schick jump between Hanley and Liam Cooper to nod past David Marshall. Schick second na wonder goal, na just few steps in take inside Scotland half as im waya shot ova di head of di goal keeper David Marshall Straight inside di net. Di result mean say Czech Republic get three points and dey ontop of group D on goal difference. Tori be say dis na Scotland first match for a major tournament for men in 23 years and e mean say dem dey bottom of di group wey get England Croatia and Czech Republic. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57474955 +sports CK Akonnor: GFA sack Black Stars coach sake of poor performance De Ghana Football Association (GFA) sack head coach of de senior national team, Black Stars, CK Akonnor. According to GFA, dis sack dey follow from Technical Report from from de Head Coach den report from de Black Stars Management Committee. Dem explain say de Executive Council after considering de two reports decide say dem go terminate de relationship with Head Coach C. K Akonnor and en two Assistants. De sack of de 47 year old head coach dey follow from poor performance after de last two games in de Group G World Cup qualifying matches against Ethiopia and South Africa. De Executive Council formed three (3) Member Committee made up of Vice President Mark Addo, Upper East Regional Football Association Chairman, Alhaji Salifu Zida and Dr. Randy Abbey who for find Head Coach and Assistant Coaches for de Black Stars within de next 72 hours. Ghanaians start dey call for de head or de Black Stars coach after de defeat against South Africa and poor game play against Ethiopia. Coach CK Akonnor performance C.K Akonnor take over as Black Stars coach in around January 2020 after Ghana Football Association (GFA) am. GFA appoint am to take over from former coach, Kwesi Appiah who at de time dey face challenges den issues of player indiscipline which people say affect de team. Since taking over de stars, he handle 10 games as Black Stars coach. Out of de 10 games, Blacks Stars win 4, lose 4 wey dem draw 2 under de leadership of CK Akonnor. After one year and nine months in charge of de national team, Black Stars statistics under CK Akonnor show say en win rate be 40%. According to football pundits, analysis of de performance of Black Stars dey show say de team dey struggle. Ghana Black Stars so far score 1 goal in last 4 matches, wey dem record only 5 shots on target in last 4 games. Some Ghanaians don dey share how de news of Akonnor sacking ontop social media. While de news dey make some people happy, others dey wonder who de next coah go be. https://www.bbc.com/pidgin/world-58552521 +politics Amended terrorism act: Nigeria Senate agree amendment to kidnapping act, wetin e mean "Kidnapping na big issue for Nigeria but kidnapping for ransom na bigger problem wey be like say e don turn to normal tin. Di matter turn to serious business venture for criminals wey dey make fast money. But di spread of kidnapping across evri part of di kontri become source of concern wey make Lawmakers for Nigeria amend di Terrorism (Prevention) Act, 2013. Di amendment na to ban payment of ransom to kidnappers. Na senator Opeyemi Bamidele committee on judiciary, human rights and legal matters sidon wit oda members to recommend wetin dey inside di amended bill. ""Di main reason for dis bill na to discourage di rising wave of kidnapping and abduction for ransom for Nigeria, wey dey spread fast across di kontri,"" Bamidele tok. Afta di presentation of di committee report di Senate pass di amended Terrorism (Prevention) Act, 2013, on Wednesday. Some high point of di amended bill include; Di last point na di most controversial aspect of di act sake of di 15 year jail term for pesin wey pay ransom. Dis dey come as some observers believe say criminalizing ransom payment go put family members for difficult situation. Pipo believe say goment no dey do enof to stop kidnapping from happening. In most cases hostage need to rely on goment and security for rescue dem from kidnapers from but e dey hardly happun. Nigeria dey struggle to tackle di deadly wave of kidnappings for ransom by armed gangs. One of di most fearful threats for families inside Nigeria s na di frequent kidnapping of pipo. Di armed gangs don tiff thousands of pipo - and dem dey usually demand for ransom. By every indication, Nigeria lucrative kidnapping industry dey boom - e dey expanding into previously safe areas. And di mata don dey look like say e dey beyond di control of di kontri military and security forces. From Southern Nigeria to di North kidnappers don become big security challenge. Any body fit be target of kidnap including schoolchildren from dia classrooms and boarding houses, pikin, old pipo, travellers, and di rest. April 2022, terrorists attack di Kaduna-Abuja train wia dem kidnap 168 passengers. Di Nigerian Railway Corporation (NRC) confam di tori and add say eight pipo die for di attack. Recently di kidnappers release foto of 62 pipo wey dey dia hostage. Goment still dey reason how to bring out di hostages. January 2022, tori of 5 year old Hanifa Abubakar wey dem allegedly kidnap and den later kill dominate internet for Nigeria. Pipo of Kawaji area of Kano state shock afta dem discover di dead bodi of Hanifa wey dem kidnap on di 4th of December, 2021 as she dey return from Islamic school wit her friends. Police discover di deadi body of Hanifa inside Northwest Preparatory school for Tudun Murtala area of Kano city. Dem arrest three pipo over di case including her teacher. July 2021, armed men kidnap 121 students from one high school for Nigeria northern Kaduna State. Afta some days di kidnappers tell di school management say di hostages dey ""well and okay"". May 2021, gunmen kidnap 136 students from Salihu Tanko Islamic school for Tegina town wey dey North central Nigeria. Parents don tell BBC say di kidnappers dey demand N100m to release dia children. One of di parents tell BBC say, di gunmen call to make demand but di demand too high. May 2021, Police for Akwa Ibom state arrest di alleged killer of job seeker, Iniobong Umoren. Di 26-year-old late undergraduate bin miss before dem discover her deadi bodi. Di suspect dey currently undergo trial for Uyo. Several courts for Nigeria dey try kidnap suspects for parts of di kontri. Di most prominent one wey court just conclude na di case of kidnap kingpin Evans, wey go now spend di rest of im life inside prison. Court find Evans guilty on Friday 25 February, 2022 nearly five years afta police arrest am. Evans, wit real name Chukwudimeme Ohamadike, dey guilty of criminal conspiracy and kidnapping, according to di court judgement. Police arrest bin Evans for Lagos on June 10, 2017. Justice Hakeem Oshodi of di Lagos State High Court Ikeja pass judgement say goment provide enough evidence to prove dem guilty of di crime." https://www.bbc.com/pidgin/61254951 +politics Ghana voter registration exercise: Ahead of Presidential and parliamentary elections, more than 15 million Ghanaians register to vote in December More than half of Ghana total population don register to vote for 2020 presidential election. Na 15 million voters for Ghana register dema names in de ongoing voter registration exercise which end Thursday 6 August. After 31 days of de registration exercise, electoral commission capture 15,117,438 people on de new voters register. Dis be de gender distribution as at phase 4 of se registration process where dem capture 11,629,480 Ghanaians. Out of dis total figure gender distribution be 5,528,970 males which dey represent 47.54 percent and 6,100,510 be females which dey represent 52.46 percent. Before Ghana Electoral Commission go start dis registration exercise, some people speculate say sometimes de EC no go fit record high turn out during de registration, but dis current figures dey prove otherwise. Deputy Chair of Ghana Electoral Commission, Dr. Bossman Asare talk say de current figures wey dem capture dey exceed de EC en target of 15 million voters. De current figure of 15 million go fit go up small by close of mop-up exercise where dem go finish de exercise for weekend. Despite say de exercise go end Thursday Ghana Electoral Commission say dem dey set aside two days for mop-up. De mop up exercise go happen on Saturday 8th August and Sunday 9th August 2020. Next Phase of activities before elections Regional breakdown Out of de number of persons registered so far, Greater Accra Region capture 3,225,508 voters, dis be de region with de highest number. Followed by Ashanti region who record 2,700,805 voters and Eastern region who dey third plus total of 1,444,274 voters. From de data wey EC supply, so far, de number of people wey chop 18 years on de register be 480,851. Voters wey chop 19 years be 419,530 and voters wey chop 20 years and above be 10,729,099. After dis registration process, Electoral Commission go exhibition of de register by September 1, 2020. Exhibition exercise go help make people check if dem capture dema names for de register which EC go take conduct de 2020 elections. Around October 15, Electoral Commission of Ghana go allow voters who want transfer dema votes to specific areas apart from where dem register. Dis transfer of votes go help make people vote for places wey dem go fit visit on December 7. After EC finish de next phase of processes, dem go now open polling stations across de country for voter to choose de Presidential and Parliamentary candidates dem go like lead dem. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53690208 +politics D-Day for Bayelsa Elections Today na di D-day. Bayelsans for South-south, Nigeria, dey go polling station to elect di next governor of the state. Di days wey lead to di election don see heavy campaign especially between di ruling People's Democratic Party for di state and di main opposition, di All Progressives Congress, APC. Some katakata don happun during di campaign, di most recent on na di PDP campaign rally for Nembe local goment area wia at least two pipo die and many odas wunjure. Although di gbege kill di spirit of some pipo, many still dey determined to comot and vote for di elections. Di two main party wey dey contend for di governorship ticket - di PDP and APC - don enta same trouser for court wey di two of dem don collect court orders and stay of execution of judgement ontop whether dem go participate for di elections. According to di Independent National Electoral Commission INEC, na 867,088 registered voters dey Bayelsa State and 769,609 don collect dia permanent voter cards wey represent 83.35%. Sensitive and non-sensitive election materials don already reach di Registration Area Centres (RAC) for di 8 Local government areas for distribution to di different-different wards and polling units. More than 32,000 security personnel don dey on ground to make sure say di electoral process is peaceful, free and fair. Many pipo for Bayelsa take advantage of di public holiday wey Governor Seriake Dickson declare, to use travel home to di riverine towns and villages in preparations to vote di pesin dem believe say go move di state forward. Some Bayelsa pipo say infrastructure like good roads and bridges na di tins wey dem go use choose di govnor. For oda Bayelsa pipo, work for di youths in di state, improved and regular payment of salaries for civil servants and pensioners, provision of portable water and stable electricity to ginger SMEs, not to forget security na di issues wey dey di minds of indigenes. Dem create Bayelsa State from Rivers State on 1 October, 1996, wit 8 local government areas. Di 23-year-old state, na one of di youngest states for di country as many dey hope for beta development and say make e happun for dia lifetime. Previous Governors of di State include di Late Chief DSP Alamieyeseigha, former President Goodluck Jonathan, Chief Timipre Silva - di present Minister of State for Petroleum Resources and di present Governor, Henry Seriake Dickson. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50439434 +sports Brazil confam friendly wit Nigeria and Senegal for October "Brazil don confam friendly match wit Senegal on 10 of October and wit Nigeria three days later for di National Stadium for Singapore. Dis go be di first ever match between Brazil and African number one team for ranking, Senegal, wey lose di Africa Cup of Nations final to Algeria. Nigeria, wey win Bronze for Egypt, go jam Brazil for di second time for senior level afta di 3-0 defeat for friendly for June 2003 for Abuja. ""We select two of di best African teams because dem be high level opponents,"" Brazil Football Confederation official Juninho Paulista tok for dia website. ""Na wetin our technical commission desire be dat. So we decide say we go follow dis opponents play"". Di friendly matches dey in line wit Brazil plan to play top 50 ranked teams whenever e dey possible. Di only oda Africa team wey Brazil don play under coach Tite na di 1-0 win over Cameroon for November last year, wey happun for England." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49727282 +sports Ghana vs Nigeria play off: Black Stars 27 man squad list to face Super Eagles "Black Stars coach on Tuesday name 27 man squad who go face Nigeria in de FIFA World Cup qualifier play offs on Friday. Ghana national football team go play Super Eagles inside de first leg of de play offs. De Gold Coast dey host de first play off for de Baba Yara Sports Stadium inside Kumasi on March 25, 2022. After dis game, de Black Stars go travel go Abuja on March 29 for de second leg of de World Cup play offs for Qatar mundial. Players for de Black Stars camp start dey arrive Ghana for trancing ahead of de clash. AS Roma player, Felix Afena Gyan share pictures of himself as he dey inside plane dey fly to Ghana for de game. He write, ""on my way to defend my country Ghana."" Dis go be de first call up for Felix Afena Gyan who blow last year after Jose Mourinho draft am from junior team into de Senior team for AS Roma. De team dey unveil new players, most of whom no play in de AFCON 2021 tournament. Arsenal midfielder go lead de squad against Nigeria in de absence of Captain Andre Dede Ayew. Deep throat sources say Thomas Partey, Afena Gyan den other players arrive already. Meanwhile, hopes be say de Black Stars players go arrive Ghana fully by close of today. Ghana dey hope say dem go fit show better performance after dem show poor performance in de 2021 AFCON. Veteran striker of Ghana national football team don criticize di decision of di kontri coach to drop Majeed Ashimeru from di squad wey go play against Nigeria. Di Black stars captain Asamoah Gyan take to social media to call out di FA say e understand why dem leave out Ashimeru from di squad. Ashimeru wey dey play for Anderlecht football club for Belgium dey in form and some Ghana fans including Gyan expect say FA for invite am afta e miss out of di 2021 Africa Cup of Nations. However, di 24-year-old no follow for Otto Addo 27-man squad wey dem release on Tuesday. ""I still insist say Ashimeru deserve to dey dis current Black Stars,"" Gyan post for Twitter. Augustin Eguavoen, coach of Nigeria national team invite 25 players for di game against Ghana. E release di list since 4 March wit seven oda players on standby - incase any tin happun to any of di players on di main list. Ademola Lookman, Emmanuel Denis, Calvin Bassey and Innocent Bonke fit get chance to play dia first game for di national team. On Tuesday di Nigeria Football federation announce say dem don drop di first choice goalkeeper, Maduka Okoye sake of say e no well. Dem replace am wit Enyimba FC goalkeeper, John Noble. Already, many of di players don arrive di team camp for di Federal capital territory, Abuja. Di 2021 African cup of Nations end for Cameroon for February 2022. Senegal win di competition afta dem beat Egypt for di final. But many fans bin dey put eyes for both Ghana and Nigeria for di tournament, howeva dem no go far. Ghana performance for Afcon dey very poor as dem leave di competition without winning any match. Dia captain Andy Ayew even chop red card for di final group match. Nigeria on di oda hand bin show some strength as dem qualify from di group stage afta topping dia group. But di Super eagles no go beyond di second round as dem lose 1-0 to Tunisia. Nigeria midfielder Alex Iwobi also chop red card for di match. For di last 71 years, Ghana and Nigeria don meet plenti times for senior level. Records show say Ghana and Nigeria don meet 49 times. Ghana win 21 while Nigeria win 10 and dem draw 18. Ahead of di play off on Friday both teams dey go as under performers - e dey hard to predict who go win." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60834326 +entertainment Gozie Okeke: Nigerian gospel artist explain why e collect money wey native doctor spray am "Nigerian gospel singer, Gozie Okeke don blast pipo wey question why native doctor, Akwa Okuko Tiwaraki go spray am money as e dey perform for one event for Oba, Anambra state, South-East Nigeria. Okeke reply im critics say notin dey bad if native doctor spray am money. For inside video e share, e say im only dey appreciate di native doctor, Akwa Okuko wey show am love as e dey spray am money. E say ""Di man begin dey spray me money, e come wit plenty money and na my duty to appreciate am because e show me love, I no see anytin wey dey bad for wetin I do."" Im reaction dey come afta viral video show how di well-known herbalist from Oba-Idemili South Local Goment Area for Anambra state take spray di gospel artiste money. Di gospel artiste wey dey popular for im Akanchawa song condemn dos wey criticise am, e say na why many of dem dey poor because dem no dey tink far. E claim say many pipo go miss heaven because dem no dey mind dia business. Di artist also shade im colleagues wey criticise am say if na dem dey im position, shey dem no go collect di money? E say shey na Holy Ghost fire dem go dey shout? Gozie Okeke na Nigerian gospel artist and music producer wey dey popular for im best selling album ""Akanchawa"". Dem born am for 24 May 1974. E dey married to anoda gospel singer Princess Njideka Okeke." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60108385 +entertainment Daddy Freeze and Oyedepo: How pipo dey react to Daddy Freeze apology to Bishop Oyedepo "Different kain reactions na im dey follow Daddy Freeze, apology to ogbonge Nigerian Pentecostal pastor Bishop David Oyedepo. For video wey Daddy Freeze bin do three years ago, im say ""anybody wey tell you say Jesus bin no poor, say Jesus bin dey rich na bastard! and im don use in left hand to point to im papa house, so im na legal bastard. Your pastor dey di same financial position as your house girl. ""Wetin im dey tok about?"" make I tok as im dey tok. I dey tok about di di bald headed fowl."" For di video im bin imitate how di Bishop dey take tok wen im say, ""wetin im dey tok about? Wen dis church dey make only three hundred naira dem dey dia?"" Di Nigeria radio presenter wey im real name na Ifedayo Olorinde apology don make social media catch fire afta im tell di Bishop sorry for di ""insult"" wey im sama give am some time back. Inside di different comments wey pipo post for Facebook, Instagram and Twitter, some support am, oda accuse am of deceiving pipo, odas say dem forgive am. Supporters of Daddy Freeze position about some men of God and di kain tins wey dem dey teach. Hailers wey believe say im do di right tin by apologising even though im no commit any offence. Oda group of pipo follow tok about how im marriage no work plus how dem feel say im dey ""deceive pipo"" wit im tok." https://www.bbc.com/pidgin/media-54137767 +health Coronavirus: Markets for Accra on shut down for disinfection exercise against covid-19 "Major disinfection exercise dey go for all markets wey dey Ghana capital, Accra as part of moves wey government wan use to manage de spread of coronavirus. Hundreds of markets and satellite markets wey develop along lorry stations all dey under lockdown after government direct say make dem lock all shops for dis exercise. Minister of Local Government, National Disaster Management Organization with support from Ghana Armed Forces enter all market spaces for de disinfection exercise against coronavirus. BBC Pidgin speak plus Korle Klottey Municipal Chief Executive, Nii Adjei Tawiah who explain say ""we dey disinfect wanna markets for here, we get like 14 markets for dis municipality."" ""We plan de whole tin for just today, but we face small challenges so sometimes if we no finish today then we go finish am morrow."" Checks from BBC Pidgin for various markets show say most shops dey under lock and key. Over 1000 officials plus de Emergency National Disinfection Exercise against covid-19 dey ground for de exercise. Ghana record 24 confirmed cases of coronavirus, out of which one person die." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51945455 +sports Why Fifa 'send home' Netherlands vs Argentina referee "Di referee wey officiate di Qatar 2022 Fifa World Cup match between Argentina and Netherlands don comot from di tournament. Antonio Mateu Lahoz dey among di top referees wey Fifa list to officiate for di World Cup. But Lahoz no go dey till di end of di tournament sake of how e take manage di game. Fifa bin open disciplinary proceeding against di Argentina and Netherlands game wey end wit bad temper. Di players of di two teams clash during a tight encounter wey see di Dutch come from 2-0 down to draw 2-2 before Argentina win on penalties. But di main tori from dat match na about Spanish referee Antonio Mateu Lahoz wey give out 18 yellows cards. ""Di Fifa disciplinary committee don open proceedings against di Dutch Football Association due to potential breaches of article 12 of  di Fifa disciplinary code in relation to di same match,"" di football governing body tok for statement. Referee Antonio Mateu Lahoz 18 cards for di Argentina vs Netherlands game na im be di highest number of cards wey referee don give for one single match in di history of di World Cup. Dutch right-back Denzel Dumfries chop red card afta e bin don collect two yellow cards. But records dey wey show oda World Cup games wia two nationals teams don fight. Some lead to plenty cards. 'The Battle of Santiago' in 1962 of Chile and Italy wia di two teams fight dem sef. Portugal last-16 win over di Netherlands for 2006 wia di ref give 16 cards and one red card. Di 2010 World Cup final wia Spain beat di Netherlands. Di English referee Howard Webb give 14 cards, including a red for Johnny Heitinga. Oda matches dey wey we no fit mention here but non of dem don near di Battle of Lusail on Friday. Of di 18 yellow cards wey Lahoz give, each of di teams collect eight cards each and den one each for Argentina team managers, Lionel Scaloni and coach Walter Samuel. Antonio Lahoz na Spanish referee wey dem born for March 1977. Im don dey ref La Liga matches since 2008. Na im officiate di Uefa Champions League final match between Manchester City and Chelsea on 29 May 2021. Lahoz don also officiate international games. Im first World Cup call-up na for di 2014 Fifa World Cup qualifiers and den di 2018 Fifa World Cup qualifiers. Later dat year, e follow for di refs wey involve for di 2018 Fifa World Cup and now 2022 Fifa World Cup." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4nr5kp0elxo +entertainment Rock and Roll Hall of Fame: Who be Tina Turner wey dey follow Fela Kuti drag number one position? "Since 1986, di Rock and Roll Hall of Fame don dey induct musicians into yearly groups, as way to celebrate dia impact for di music industry. Dis year, fans go vote, between 16 nominees, who go make am enter di top five of di ‘class of 2021’. Although Fela wey be di father of Afrobeats ‘Fela’ dey lead oda 2021 nominees for voting (as at when we publish dis tori), anoda ogbonge musician don dey give di late Nigerian legend tough time for di number one position. Who be dis person? Meet Tina Turner, eight-time Grammy awards winner and “Queen of Rock 'n' Roll"". For those wey no sabi her, madam Turner na di person wey sing di 80s classic song “What’s Love Got To Do With It” wey win three Grammys for 1985. Di music, fans, and personal story of Tina Turner, na one of di reasons why she get di kain big clout wey reach to challenge di late Fela Kuti, wey millions of pipo across di world sabi for im visionary music. 5 sharp-sharp facts wey you fit no sabi about Tina Turner About 2021 Rock and Roll Hall of Fame Seven out of di 16 nominees dey di ballot for di first time, including American rapper JAY-Z, R&B singer Mary J. Blige and Fela Kuti. Na di top five musicians wey fans vote for go make am into di class of 2021; Dis mean say dia record go dey di Rock and Roll Museum for city of Ohio, United States. https://twitter.com/wizkidayo/status/1378309469512273924?s=20 So e no really matter who get di most votes (as long as e dey top five), although dis no stop fans of Tina Turner and Fela Kuti to try push dia favourite musician to number one position. Since voting open for February, Tina don lead sometimes, and Fela too don lead. Many big names for Nigeria music today, like Wizkid, follow for those wey dey use social media to encourage pipo to vote for di Afrobeats legend to carry first. Voting go end by 30 April." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56644348 +sports Afcon 2021: Players wey Premier League and oda Leagues go miss during Africa Cup of Nations tournament As night dey fall and Day dey break, di clock for di 2021 Africa Cup of Nations dey tick. Pipo wey like football don dey imagine how di 52 matches go shele . Dis Afcon na di biggest football tournament for Africa, and na evri two years e dey happun. E dey pepper African players bodi if dem no call dem for National team or if dem miss out for any oda reason. Di ogbonge football tournament no dey only pepper players wey miss am, dia absence dey also affect football clubs too, especially di ones for Europe. Dis na becos many of dem go dey witout dis players for period wey fit reach six weeks if dia team reach di final. Arsenal na one of di teams wey dey affected pass as dem go miss upto five players. Watford go dey witout four, same number wit Leicester City. Na almost forty Premier League players na im get call up to go represent dia Kontris. And na Sixteen Premier League clubs dis Afcon affect, plus oda ones wey we no count. Out of di many players wey dia kontris invite, make we check di ones wey ansa dia name and di ones wey no fit. Arsenal: Thomas Partey (Ghana), Pierre-Emerick Aubameyang (Gabon), Nicolas Pepe (Ivory Coast), Mohamed Elneny (Egypt), Omar Rekik (Tunisia). Aston Villa: Bertrand Traore (Burkina Faso), Trezeguet (Egypt). Brentford: Frank Onyeka (Nigeria), Julian Jeanvier (Guinea), Tariqe Fosu-Henry (Ghana). Brighton: Yves Bissouma (Mali). Burnley: Maxwel Cornet (Ivory Coast). Chelsea: Edouard Mendy (Senegal). Crystal Palace: Cheikhou Kouyate (Senegal), Jordan Ayew (Ghana), Wilfried Zaha (Ivory Coast). Everton: Alex Iwobi (Nigeria). Leicester City: Kelechi Iheanacho (Nigeria), Wilfred Ndidi (Nigeria), Daniel Amartey (Ghana), Nampalys Mendy (Senegal). Liverpool: Mohamed Salah (Egypt), Sadio Mane (Senegal), Naby Keita (Guinea). Manchester City: Riyad Mahrez (Algeria). Manchester United: Eric Bailly (Ivory Coast), Amad Diallo (Ivory Coast), Hannibal Mejbri (Tunisia). Southampton: Moussa Djenepo (Mali). Watford: William Troost-Ekong (Nigeria), Imran Louza (Morocco), Adam Masina (Morocco), Ismaila Sarr (Senegal). West Ham: Said Benrahma (Algeria). Wolves: Willy Boly (Ivory Coast), Romain Saiss (Morocco). While di tournament be Africa biggest football showpiece, some of di continent stars go miss out due to injuries, refusal of clubs to release players and fallout wit dia national team managers. Hakim Ziyech - Morocco and Chelsea Odion Ighalo - Nigeria and Al-Shabab Victor Osimen - Nigeria and Napoli Emmanuel Dennis - Nigeria and Watford Ogenekaro Etebo - Nigeria and Watford https://www.bbc.com/pidgin/sport-59903092 +entertainment Oxlade: Why Nigerian singer Oxlade alleged 'sex tape' dey cause so much tok-tok for Nigeria social media space "Nigerian singer, Oxlade become number one trend for social media space on Wednesday afta one video show for social media wey pipo tag 'Oxlade sex vdeo'. Di video wey don since go viral don cause pipo to tok. Although di hit-maker neva comment on di alleged sex video, many of im fans don sharperly enta social media to hail am. However, some pipo don criticise pipo wey dey hail Oxlade 'sex tape'. Dem question why dem no keep di same energy when fellow singer, Tiwa Savage sex video leak some months ago. ""Oxlade sex tape leak and everybody dey praise im stroke game, wia di energy dey wen it was Tiwa?"", one Twitter user ask. Singer Tiwa Savage bin comot to tok say pesin dey try blackmail her wit her short sex clip. She share dis tori for one radio show - The Angie Martinez show - for New York Power 105.1 fm on 8 October. ""I no go call am sex tape, but na video of me wit di pesin wey I dey see (date) right now"", na so she tok Tiwa say dem share di video wit her wey show her wit di bobo wey she dey currently date and she say di pesin wey get di video come dey blackmail her and dey ask for money. Di alleged video later surface for social media wey make many of her fans para. Dis one don make pipo raise questions about gender disparity and why pipo no criticise Oxlade as dem do Tiwa See wetin pipo tok: Im real na Ikuforiji Olaitan Abdulrahman Di Nigerian singer and songwriter become popular afta di release of im song ""Away"", wey appear on Rolling Stone 50 best songs of 2020. Di song also make am gbab Headies nomination for year 2020 next rated award. For one interview wey im get wit BBC Pidgin, Oxlade say im start im singing career for inside church. Im reveal say na im grandparents raise am as im lose im mama at di age of three . E also tok say im drop out of school for im final year based on reasons wey im no dey like tok about but e dey life threatening. ""E be like blessing in disguise. As I bin comot school, e give me chance to focus on my career and my music."" Since im career blow for 2020, Di singer don drop many oda hit songs like 'Oxygen', Im dream na to become one of di biggest Afrobeat export from Africa. Oxlade no be di only first and only Nigerian celeb wey don get 'Sex video' gbege For April 2020, Nigerian waka singer,  Salawa Abeni bin burst pipo head afta she say pesin bin dey blackmail am say dem go post her naked pictures if she no give them money. For di Instagram post she reveal say she bin either dey for hospital or with her partner when dem take di pictures but tok say she no go let anyone bully her as she post di pictures herself. Later police come arrest di alleged blackmailer wey bin dey di age of 19. For 2017, video comot of di Mosquito Killer singer dey masturbate for inside Snapchat. Tori pipo tok say im later comot to reveal say na hack dem hack im phone post am. One of di most controversial Big Brother Naija reality TV show housemates, Tacha bin receive blackmail for 2020 for nude pictures wey she say bin dey edited. She come on Twitter to post di email wey she bin get. For April 2020, media personality Toke Makinwa bin face blackmail by pipo wey tok say dem go post her nudes except she pay dem. For Instagram post wey she later comot, she post di picture and tok say di one wey dem bin dey blackmail her with dey photo shopped. For 2018, video bin comot for di Ghana Dancehall artiste snapchat wey apparently show one woman dey give am blowjob. E later post video on top im same snapchat wia e confam di video wen e ask weda dem neva see pesin dey collect head before. Howeva im no confam weda di pesin wey dey di video na him." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60314988 +entertainment Kizz Daniel: Oluwatobiloba Daniel Anidugbe born triplets but one die "Nigerian musician Kizz Daniel don reveal say im born triplets but lose one four days later. Oluwatobiloba Daniel Anidugbe, wey everybody know as Kizz Daniel tok dis one for inside social media post. For di post Kizz Daniel say ""God bless me wit three boys a while back Jamal, Jalil and Jelani ( triplets)."" ""Four days afta Jamal die"". Di singer add as im post scan image of di triplets. Kizz Daniel also reveal di first gift e buy for im sons. ""Congrats to di latest home owners in town , Jelani and Jalil"". e tok. Dis dey come few months afta im announce di birth of im twins on im birthday for May dis year. Tori be say for one interview wey Kizz Daniel do wit tori pipo Punch e say im dey like keep im relationship private, even before im become popular. According to am ""I make di decision to keep my relationship private long time ago before I become famous and I don decide to keep am dat way."" Kizz Daniel na popular Nigerian musician wey dem born for Abeokuta, Ogun state for May 1, 1994. Im papa na famous artist and lecturer for Ogun State. Di musician father, Kola, support Kizz dream of becoming a singer, but e also encourage am to complete im education as well. Na 2014 di singer Kizz release im debut single, Shoye, G-Worldwide Entertainment label. E release Woju afta shoye wey blow well-well and since then e don go on to produce more hit songs like yeba and Madu just to mention a few. For 2017, afta di wahala wey im bin get wit im den record label G-Worldwide Entertainment afta dem carry am go court on top songs wey im wan release without di company approval. E change im name from 'Kiss Daniels' to Kizz Daniel." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57845815 +entertainment Rita Dominic: Interesting facts about Fidelis Anosike wey Rita share im picture for instagram "Nollywood actress, Rita Dominic post a picture of herself and Fidelis Anosike together for her Instagram page wit di caption ""Merry Christmas"" plus love emojis. For inside di picture Rita Dominic and Fidelis Anosike bin sit close to each oda, raise a glass of wine for wetin be like a ""love relationship pose"", dem also wear matching outfits for di second picture of dat post. Rumors bin dey fly upandan say di Nollywood actress bin dey set to marry Fidelis Anosike but BBC pidgin neva fit confam dis tori yet. But wetin we sabi about Fidelis Anosike wey Rita share im picture for instagram post? Fidelis Anosike na di owner and publisher of Daily Times Newspaper, one of Nigeria popular local newspaper Im acquire di Newspaper for 2007 under di Folio Communications afta goment bin close di newspaper former ownership down sake of some gbese. Fidelis start Folio Communications at di age of 24 afta im graduate from University of Benin wia he study Creative Arts Im be di Chairman and Chief Executive Officer of Folio Communications Limited before e announce im resignation from di Company board for June dis year to make Mr. Aliu Akoshile di new Chairman of di company. He say Folio Communications Limited na conglomerate, wey im found at a very young age .d '' I dey very proud of wetin we dey able to achieve which suppose be inspiration for young pipo,"" he tok wen e announce im resignation. Oda companies unda di Folio Communications conglomerate na: Folio Nigeria powered by CNN, di Daily Times Nigeria, Miss Nigeria, 1st October, Times Multimedia and Creative Africa Xchange (CAX). Fidelis bin once tok about im family say im papa na junior police officer wey die at age 52, leaving im uneducated mother to labour to train five boys and three girls." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55453531 +sports Blessing Okagbare: Nigeria Sprinter chop 10 years ban for 'multiple' anti-doping breach "Nigerian sprinter Blessing Okagbare don chop 10-year ban for ""multiple breach of anti-doping rules"". Di Athletics Integrity Unit (AIU) say di 33-year-old bin chop ban for five years for di use of multiple prohibited substances and five for not co-operating wit di investigation. Okagbare bin chop suspension during di Tokyo Olympics after she fail one drug test. Brett Clothier, head of di AIU, say 10-year ban na ""strong message against attempts to cheat"". Okagbare win silver medal for long jump for di 2008 Olympics and also win World Championship medals in di 200m and long jump. She bin also contest medal for di women 100m for Tokyo last year and win her heat for 11.05 seconds. But dem rule her out for di semi-finals afta AIU say she test positive for one human growth hormone afta one out-of-competition test on 19 July. For October, dem charge Okagbare wit three anti-doping offences, wey she deny. Okagbare get 30 days to appeal against di AIU disciplinary tribunal decision for di Court of Arbitration for Sport (CAS). World Championships Silver 2013 Moscow Long jump Bronze 2013 Moscow 200 m Commonwealth Games Gold - 2014 Glasgow 100 m Gold - 2014 Glasgow 200 m Silver - 2014 Glasgow 4×100 m relay Bronze - 2018 Gold Coast 4×100 m relay All-Africa Games Gold - 2011 Maputo Long jump Gold - 2011 Maputo 4×100 m relay Gold - 2015 Brazzaville 4×100 m relay Silver - 2007 Algiers Long jump Silver - 2011 Maputo 100 m African Championships Gold - 2010 Nairobi 100 m Gold - 2010 Nairobi Long jump Gold - 2010 Nairobi 4×100 m relay Gold - 2014 Marrakesh 100 m Gold - 2014 Marrakesh 4×100 m relay Gold - 2018 Asaba 4×100 m relay Silver - 2012 Benin 100 m IAAF World Relays Gold - 2015 Nassau 4×200 m relay Continental Cup Bronze - 2010 Split 100 m" https://www.bbc.com/pidgin/sport-60419103 +sports Afcon 2019: Black Stars fit win di cup for Egypt - Christian Atsu Di Black Stars of Ghana don win di African Cup of Nations four times. Di last time wey di team win am na for 1982 and most Ghanaians don dey hungry for anoda win for di tournament. Dis year, dem dey Group F wit Benin, Cameroon and Guinea Bissau. https://www.bbc.com/pidgin/media-48732052 +politics Cameroon Elections 2020: Without Braille paper ah no sure for vote candidate of ma choice Evelyne Angonweh Longni na one of de 13,000 pipo dem for Cameroon weh deh get visual disability weh deh no sure say deh di vote dia choice for candidate. Cameroon go vote lawmakers and councillors for number 9 day for February, and dis group of pipo di also worry how for climb for upstairs for vote as deh no di see. Because for last election Braille paper no bi dey, e no di encourage dem for vote but hope dey say dis taim Braille ballot paper go dey. Elections Cameroon, Elecam promise say deh go put Braille ballot papers for all polling stations for kontri. Some pipo wit visual disability di doubt if braille go bi for all polling stations, deh wan see before deh believe. Kenfack Francois, President of Cameroon Society of Persons with Disabilities say deh select some polling stations laik Centre of the young rehabilitated blind people, CJARC for put Braille ballot papers. Kenfack di hope say wit taim, braille ballot papers go fit bi for all polling stations. https://www.bbc.com/pidgin/media-51391526 +health Coronavirus cases in Ghana: Over 700 pipo contract Covid-19 for dema workplace within one week "Workplaces for Ghana like factories, offices and markets turn hotspot for de spread of Covid-19, Ghana Health Service (GHS) reveal. Dr Patrick Aboagye, GHS - Director General talk say from de data wey dem gather ""all de new hotspots dey come from workplaces, so we for make sure say workplaces be spacious, hygienic environment and social distancing dey."" One industrial food processing company, Pioneer Food Cannery record 533 Covid-19 cases for Tema. Ghana health service san reveal say another mass infection happen for Obuasi market, where over 200 people test positive for de virus. If you put de two figures together, e mean say within one week a total of over 700 people contract Covid-19 for dema workplace. Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah explain say if you add the Obuasi market and Tema factory incident, e dey give rise to concern for workplace vigilance. ""De offices wey open for start be vigilant, workplace management strategies like sterilizing tins like door knobs and stair reel for happen"" he add. Ghana health officials shut down Obuasi Market sake of de number of infections, wey de Tema industrial factory reduce dema productions so say small number of people go come work. De reason de virus dey spread easily be sake of people dey work to close to each other. Researchers for Carolina School of Science and Mathematics say bugs, germs, viruses and bacteria dey spread easily for offices sake of people dey interact more plus other people who fit infect them." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52647947 +business Fuel Subsidy: Nigeria goment approve N3tr for am plus oda tins you need to know "Di Nigerian goment don approve three trillion naira to maintain fuel subsidy for di next 18 months. Di Federal Executive Council (FEC) approve di money during dia weekly meeting for Presidential Villa, Abuja on Wednesday. Minister of Finance Budget and National Planning afta di meeting tell tori pipo say di federal government propose N3 trillion budget to meet di increase of di fuel subsidy request for di 2022 budget. According to Zainab Ahmed, di kontri no get enough money to fund di fuel subsidy for di whole 18 months. ""Na only N443 billion naira we capture for di 2022 budget for subsidy to cover cost from January to June,"" Ahmed tok. She say as FEC don consider di new request by di National Petroleum Company, di ministry go approach di National Assembly to amend di fiscal framework and di budget. ""Wetin dis wan mean be say we need to make incremental provision of N2.557 trillion to meet di subsidy requirement. ""Dis one go be average of N270 billion per month,"" di minister explain. Di Nigeria Governors' Forum (NGF) say any action wey goment take on di removal of fuel subsidy must directly benefit di pipo. Di govnors tok dis one during dia meeting wit Nigeria Labour Congress (NLC) for Abjua. Di NGF and NLC criticise di Nigerian National Petroleum Corporation over di mismanagement of fuel subsidy regime for di kontri. ""We need partnership wit NLC to confront di challenges of wetin NNPC det do because di fraund too much,"" tok-tok pesin for di forum Abdulrazaque Bello-Barkindo write for statement. Di whole confusion about di fuel subsidy make Nigerian lawmakers vex - especially di amount of money wey goment dey spend. Dis wan make di National Assembly decide to torchlight how much petrol di kontri dey use. Di lawmakers also wan investigate wetin dey happen to Nigeria refineries. Speaker of House of Representatives, Femi Gbajabiamila say lawmakers go consider di decision to pay subsidy on petroleum subsidy, goment need to answer some kain questions. Fuel subsidy na one of di tins wey Nigeria goment dey spend plenty money on, for a very long time. But many Nigerians neva too understand wetin e mean. Fuel subsidy na money wey goment dey pay so dat fuel price no go too cost for Nigerians. If goment stop to pay subsidy, di price of fuel go increase and e go affect di price of goods and services. Di official reason for oil subsidies na to reduce di impact of rising global oil prices on Nigerians. Fuel subsidy don dey di kontri since di 1970s. Dem institutionalise am for 1977, under di regime of General Olusegun Obasanjo wit di promulgation of di Price Control Act wey make am illegal for some products (including petrol) to dey sold above di regulated price. Between 2006-2018 Nigeria spend about 10 trillion Naira on petroleum subsidies. Since Nigeria transition to civilian rule for 1979, many administrations and regimes don try to comot subsidy. President Shehu Shagari bin raise di price of petrol in 1982, from 15.3 kobo a litre to 20 kobo. For 1986, President Ibrahim Babangida announce partial removal of oil subsidies, wey see petrol price increase from 20 kobo to 39 kobo per litre. For 2012, President Goodluck Jonathan attempt to remove fuel subsidy. Di mata cause serious protest for di whole kontri. For June 2020, goment of President Muhammadu Buhari tok say dem go remove fuel subsidy but by March 2021, di goment say dem go keep di price di same. And for January 2022, Nigeria goment say di removal of fuel subsidy go need to wait for anoda eighteen months. Di Minister of Petroleum Resources Timipre Sylva say dem go tell di national assembly to extend di period to implement di removal of di subsidy till 2023." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60153932 +politics South Africa president Ramaphosa dey on track to win ANC race afta cash scandal "South Africa governing ANC don start dia national conference dis Friday morning to elect new leadership. President Cyril Ramaphosa dey hop to dey re-elected as party leader afta e escape one impeachment inquiry earlier dis week. Dis na afta ANC MPs vote against di adoption of one report wey found say e fit don breach di kountri anti-corruption legislation following di theft of one large sum of foreign currency for im private game farm. Oga Ramaphosa go face off against former Health Minister Zweli Mkhize for di top post. E dey widely expected say di party integrity committee go table dia report about di ""Farmgate"" scandal wey almost cost Oga Ramaphosa im job and one corruption scandal wey entangle im competitor. E dey alleged say Dr Mkhize benefit from one Covid-19 goment tender where communication contracts dey awarded to im allies. Dem go follow dis one by di adoption of credentials - one process wey fit go on for hours and dey usually contested by many factions sake of na dat one go determine which delegate dey eligible to take part and vote. Oga Ramaphosa dey likely to retain im position despite di recent setbacks. Meanwhile, South Africa former President Jacob Zuma say im don launch one private prosecution against im successor Cyril Ramaphosa. Jacob Zuma Foundation make di announcement on Thursday night say President Ramaphosa dey charged for ""serious crimes"" for one Johannesburg court. Dem add say di crimes carry sentence of 15 years for prison. For one response for Twitter on Friday, President Ramaphosa accuse Oga Zuma of ""abuse of legal processes"". E say di charges dey ""completely fake and unfounded"". If you never sabi di details of di scandal wey threaten to end di political career of South Africa President Cyril Ramaphosa not heard here be wetin you need to know." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c51qeyyk3g1o +entertainment Poco Lee and Portable: Zazu Zeh star settle with Poco Lee and Kogbagidi say na 'promo'- See wetin bin cause di kasala "Fast rising Nigerian musician, Portable Omolalomi don reunite with dancer, Poco Lee and promoter, Kogbagidi afta e bin rant and accuse Poco Lee for social media. To prove say all dey well, Portable share fotos of imsef togeda with Poco Lee, Kogbagidi and Musician, Olamide wey im dey call e benefactor for im Instagram handle. Also, di Zazoo Zeh star tok for one recent viral video with Poco Lee say everything wey bin happun between both of dem na 'promo oh.' Then Poco Lee reply for di say e no carry 'Potable money oh' contrary to di accuse wey di Zazoo Zeh musician bin accuse am before. But Poco Lee later come share one video of singer Burna Boy as e dey mimic Portable and write say; ""Funny how I gatz to accept wetin no dey true for peace to reign, I show love oooo."" Kogbagidi post for im social media handle with video of dem all say dem be one happy family. ""ONE HAPPY FAMILY: True leaders understand say we become stronger pulling odas up, Kogbagidi write. ""Big respect and love to di Big Fish for dis game, Olamide and my day one brother Poco Lee , you know I go stand by you , come rain come shine."" ""Time don show you be true leaders . Your son Portable Omolalomi knows better now . E dey ready to learn and tap from your wealth of experience for di industry ."" On Tuesday 21 December, Portable bin share one videos online where e accuse Poco Lee say e dey show am love but e just dey try to cheat am. Portable claim say Poco Lee dey try to steal e 'Zaazoo Zeh' song and hala say di song no belong to Poco Lee E say afta Poco Lee allegedly pick di $3,000 wey Wizkid spray am for stage, e only give am $600 out of di money. Dis accuse come result to serious tok-tok for social media sotey e come make Portable music promoter Kogbagid vex for am. Later dat day, Kogbagidi share video of wen e dey drive portable comot from hotel room and write say:""Unruly and unprofessional conduct dey always expected from upcomings."" ""You never fit tell wetin dey go on for dia mind or head. I dey shock and embarrass at dis point. Do I need to fix your career and your head at di same time? Kogbagidi ask. Afta all di gbas-gbos for social media and reactions from Nigerians, Portable come apologize give e benefactor, Olamide and all di pipo wey im sama accuse give. ""My sincere apologies dey go out to my benefactors Olamide, Poco Lee and Kogbagidi,"" Portable post for e Instagram handle togeda with video. ""I dey di learning process, I know better now . Kindly forgive me and pardon di street in me. Much love and appreciation to all my fans, words cannot express my feelings right now . ""Thanks for di intervention and words of comfort. Now I know say I no dey alone for dis . Love you guys . I no ever let you down again. Expect more from your boy. Zeh nation."" Di latest for di mata be say Portable and Poco Lee togeda with Kogbagid don reunite and settle dia difference afta Olamide chok mouth for di mata. Portable Omolalomi real name na Habeeb Okikiola be rapper, singer and songwriter. Di self-proclaimed Son Of Shaku Shaku, don climb di ranks of di kontri fastest-rising singers. Portable Olalomi come from Ogun State, South West of Nigeria. For one video wey im share for im tiktok page, e tok say na Nigeria rap star, Olamide bring am to limelight. Dem bin also share video of wia im meet wit di Nigeria rap star." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59766162 +sports Deontay Wilder v Tyson Fury II: Who go win? "Tyson Fury and Deontay Wilder go face each oda again for early mor-mor on Sunday, almost 15 months afta dia last fight end for draw for Los Angeles. Tickets for dia Las Vegas fights dey go for thousands of dollars, already di fighters dey badmouth each oda ahead of di fight. Di big prize na Wilder WBC world title. If Fury win am e mean say all four heavyweight belts go dey shared between two British fighters - him and Anthony Joshua, go hold di IBF, WBA and WBO titles. Wilder dey start as favourite according to betting pipo before di fighters go waka enta di ring around 05:00 GMT on Sunday morning. Dis na everything you need to know about di fight. Na few tickets remain for di fight wey go happun for MGM Grand Garden Arena, di ticket prize na from $425 (£330) for open market to $10,000 (£7,754) for black market. For Las Vegas Strip, fans fit pay $100 (£77) to watch di fight for big screen while di fight go cost $74.99 (£58) to buy for house for pipo wey dey live for US, e mean say dem fit raise up to $150m (£116m) even before dem collect ticket money. In terms of money for di two men dia money fit reach eight- figure for dat night alone. Na di biggest heavyweight fight for 20, 30, or even 50 years - dat na if you listen to wetin Fury dey tok. ""I don dey here for 25 years and I neva see dis kind investment for pay-per-view fight,"" na wetin BBC Sport boxing correspondent Mike Costello tok. Im 5 Live Boxing sidekick Steve Bunce add say: ""Two men wey dey unbeaten, elite versus elite. Make wey no forget say we dey see something wey we no dey every day. Dis na monster."" Some UK betting company dey put Wilder as slight favourite for di sports betting facility for MGM Grand, wia some big spenders fit force di prize to change as di fight dey near. Costello add say: I feel say Wilder don learn from im first fight and e go dey better dis time to close di space dem. I know when im go catch Fury but I feel say im go catch am."" Bunce respond: ""I feel say we go see Wilder box small and Fury go dey more aggressive. I no think say dis changes dem go last. I believe say Fury go survive some difficult moment and then win on points. And yes, e go dey controversial."" Sabi pipo and betting pipo dey divided. ""Dis na di moment we don dey wait for tey-tey,"" dat na wetin Wilder tok dis week. Dis na di latest twist for dis rivalry. At least di waiting dey nearly over. Wilder neva too change, so di result of dis fight go depend on di success of failure of di changes Fury don make. Outside di gym, im profile for US don rise, wey don also bring new demands. Inside di gym, im get one new trainer. SugarHill Steward, wey be policeman before, dey call imself ""di knockout architect"", afta im learn how to box for di legendary Detroit Kronk Gym. Fury get new cuts man - in case di wound wey need 47 stitches after im September win over Otto Wallin open again - and im also hire di chef wey UFC star Conor McGregor dey use. Im no dey drink Diet coke, drink wey im like well-well. Di most important one of all dem na im promise to move away from im style and any try to knock out deadly puncher. ""Wetin I do di last time clearly no dey good enough, so we go for di knockout,"" na wetin Fury tok. ""I feel say Wilder go come out of di gates like horse wey dey run to try to knock me out.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51591870 +entertainment "#How it started: Di new ""How it started - How it’s going"" challenge wey don catch fire for social media" "Di ""How it started - How it's going"" challenge na one new challenge wey don begin gada momentum for social media. E no clear who start di challenge but many pipo including celebrities, businesses, organizations from around di world don join do di challenge. Di challenge no dey limited to any particular year, e just dey show how far pesin don journey for life. Wit just two fotos, pesin go understand where you start from and where you dey now. Most of di fotos wey pipo share na about dia love story take start from simple DM to marriage, relationships and hustle." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54481826 +health Nigeria coronavirus stats: 4000 Nigerians abroad wan return, dis na how e go happun - FG About 4000 Nigerians wey dey live abroad don make up dia mind to return home sake of Covid-19, according to wetin di foreign minister Geoffrey Onyeama tok. Oga Onyeama tok dis one during di daily report wey di presidential task force for Covid-19 give on Monday for Abuja. But di federal goment of Nigeria don torchlight conditions and how di transport back go happun. Inside tweet wey di Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) release, Onyeama reason am say although e sweet im belle to help all di 4000 pipo, e no go fit happun as beds for isolation centres no go reach. Meanwhile, di Nigerian embassy for America bin comot informate on 3 May for how di Nigerians for US fit return. Di main tins from di statement wey di Nigerian Consulate General release ontop embassy website be say: https://www.bbc.com/pidgin/tori-52544127 +politics US Election results 2020: Dr Stella Immanuel predict 'win' for Trump "One Cameroon doctor wey dey based for US hold prayer session on Thursday to help President Donald Trump secure im re-election. Dis one dey come as di Democrat candidate Joe Biden currently dey lead with 253 electoral votes while Republican candidate Donald Trump get 214 electoral votes. For inside video wey Dr Stella Immanuel, post for her Facebook, she say ""I release warrior angels to go through dis nation right now and begin to scatter di plans of di enemy, di plan of di wicked to take ova dis nation, to destroy our economy to destroy our pipo in di name of Jesus."" For di video, she wear blue and yellow Ankara cloth and sidon alone inside one room dey pray she even use bible reference of Zerubbabel join di prayer wia she add say ""Di hands of Donald J Trump wey begin dis work for dis nation im hands go complete as you show me and many prophets for dis nation."" But no be only her wey don go spiritual ontop di US election mata. On Wednesday, 6 November, Donald Trump spiritual adviser, Paula White-Cain bin lead prayer service to request for angels from Africa and South America to help am win di US Presidential election. Paula White-Cain wey also be Televangelist tok for prayer say she dey hear sound of victory plus sound of shouting and singing. For July dis year, Dr Immanuel make di news afta she claim say she use hydroxychloroquine, zinc, and antibacterial drug, Zithromax to treat Covid-19 patient for United States of America. Dr Stella Immanuel na primary health physician wey dey work for Rehoboth medical centre for Houston Texas." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54836870 +politics In Fotos: How thousands gada to witness swearing-in of new Kenya president "Na thousands of pipo gada for di venue for Nairobi wia dem swear in William Ruto as Kenya president. Wit im hand on top Bible, di 55-year-old swear to preserve and protect di kontri constitution. Raila Odinga wey lose for di election no attend di inauguration, say e get “serious concerns"" about im opponent victory. Oga Ruto win di election wit 50.5% of di vote, to Odinga 48.8%. Odinga allege say dem rig di election but Supreme Court don rule say di election was free and fair. At least eight pipo injure for di stampede wey happun for di venue of di inauguration. Di stampede happun as di crowd dey try enta di stadium to witness di swearing in of both Ruto and im deputy Rigathi Gachagua. But inside di stadium, di crowd happy well-well as dem dey gyrate dey wave Kenya flag while odas wear yellow – di colour wey pipo take sabi Ruto campaign. Nigeria Vice President Professor Yemi Osinbajo travel go Nairobi to join oda African leaders to attend di inauguration of William Ruto. Local media say na 20 African heads of state dey invited to attend di swearing in. Tanzania President Samia Suluhu, Seychelles President Wavel Ramkalawan, Burundi Évariste Ndayishimiye and Eswatini Prime Minister Cleopas Dlamini also attend. Odas na Malawi President Lazarus Chakwera and Guinea Bissau Umaro Sissoco Embaló. William Ruto, di winner of Kenya heavily disputed presidential election - get di same childhood wey be like dat of many poor Kenyans. Ruto go primary school without shoes. E wear im first pair of shoes for di age of 15. E bin also sell chicken and groundnuts for roadside for rural areas of di Rift Valley. So e no come as surprise say e show imsef as di champion of di poor as e vie for di presidency for di 9 August election. Oga Ruto contest under di banner of Kenya Kwanza, Swahili for Kenya First, wit a promise to grow di economy. Dis na di first shot of di 55-year-old at di presidency and e shock im critics by achieving victory. E join politics in 1992 afta di den President Daniel arap Moi mentor am. Oga Ruto bin dey part of di youth wing of oga Moi once-dominant Kanu party. And im dey among di activists wey dey tasked wit mobilising voters for di kontri first multi-party elections wey hold for di same year. William Ruto, wey be Deputy to out-going President Uhuru Kenyatta, get di reputation of being a powerful orator - pesin wey sabi tok- wey dey draw huge crowds for rallies. And im dey put up strong performance for media interviews. Ruto dey often start to tok by saying ""My friend"", wey dey always help am strike rapport wit voters and take di critics unaware." https://www.bbc.com/pidgin/articles/ck58e8z8ye5o +politics Five lessons we learn from Ekiti govnorship election "By Victor Ezeama Di governorship election for Ekiti state don end afta one day of voting without major wahala. Na former Secretary to di State Goverment, Biodun Oyebanji, win di low-key election. Kayode Oyebode, returning officer for di election, announce Oyebanji as governor-elect of Ekiti state early mor-mor of Sunday.\nOyebanji secure 187,057 votes to win di election. E defeat im two closest rivals — Segun Oni of Social Democratic Party (SDP) wey get 82,211 votes, and Bisi Kolawole of Peoples Democratic Party (PDP) wey get 67,457 votes. ""Say Abiodun Abayomi Oyebanji of APC, having satisfied di requirements of di law, dey hereby declared  winner and returned elected,” di Inec returning officer for di election announce. Dis na di major takeaways from di election. Di election start well on Saturday 18 June as adhoc staff of di Independent National Electoral Commission (Inec) arrive dia polling stations early.\nVoters also arrive dia units early to begin confam dia names for Inec list and prepare to vote. Police and security deployment also dey available to ensure say jaguda pipo no scatter di election.\nDi election start as Inec plan am by 8:30am and by 10:30am election don finish for some polling units. Wen dem swear am in Biodun Oyebanji go become di 8th govnor of Ekiti state since Nigeria return to democracy for 1999. Since di return to civilian rule, record show say no party don dey for goment back to back for Ekiti. Dis na because di state no dey experience political continuity. Becos of dis, every govnorship election for Ekiti since 1999 don produce different winners from different political parties. Although Oyebanji na different pesin from di current govnor Kayode Fayemi, dis na di first time di same political party dey retain power for di state. Im performance for office go determine if APC go remain for power afta 2026. Di Peoples Democratic Party (PDP) na di main opposition party for Ekiti state but dem carry third position for di election. According to Inec, candidate of di PDP Bisi Kolawole get 67,457 votes - behind Segun Oni of Social Democratic Party (SDP) wey get 82,211 votes. Dis one happun despite say oga Oni just join SDP three months to di election. Before di election, di PDP for di state bin get ogbonge crisis wey even di national leadership of di party no fit resolve. Di fight na between one serving Senator Abiodun Olujimi and former govnor Ayo Fayose - di two dey drag who be leader of di party for di state. Dem carry di wahala go dia primaries wey produce Bisi Kolawole wey many pipo feel say na weak candidate. Also, di fight between former Deputy govnor Kolapo Eleka and Fayose also further contribute to di division of di party. For di 18 November, 2021 governorship election for Anambra state, Inec introduce di Biomdial voter accreditation system (Bvas) for di conduct of election. Di Bvas machine na to allow voters accredit and vote at di same time. But di machine no work well for Anambra. However, Inec say di machine go remain for Nigeria election process and dem go make am good as di commission dey conduct more election. Dis na why Inec improve di functionality of di machine ahead of di Ekiti election. Dem deploy di machine wey make voting fast and easy. Complain no too dey from voters about di use of di Bvas machine. Na for dis election Inec also test wetin dem call electronic transmission of results. Unlike before wey polling officers go need to carry hard copy of result sheets go local moment for collation - now dem get transmit di result electronically to Inec and den later go submit di hard copy for verification. Dis one make di collation result for Ekiti dey very fast and easy. As at 5pm on Election Day Inec don receive results from 14 out of di 16 local government areas of di state. Di e-transmission also make am hard for pipo to alter or tamper wit results from polling units. ""See and buy"" and ""our vote no be for one pot of soup"" na di popular slang wey voters dey tok during di election on Saturday. Dis na sake of di clear cases of vote buying for majority of di polling units for di state. Vote buying na one of di most popular election offences for Nigeria. Di trend don grow over di years becos political parties bin dey hide dey do am. But dis days, dem don dey do am openly. Sadly, most voters dey also look forward to collecting money afta voting. Odas dey even show am for social media. For Ekiti, Nigeria anti corruption agency Economic and Financial crimes commission (EFCC) arrest some pipo on allegation say dem dey pay voters. Videos wey dem post for social media show wia dem parade some of di suspects wit cash and names of voters. Also, election monitoring group Yiaga Africa for dia preliminary report say dia observers ""find out several cases of vote buying during di election. ""Di vote buying dey happun for open spaces and some parties dey pay as much as N7 ,000 per vote."" Overall, Inec prepare well for di election and finish am on time but di issue of vote buying na big problem." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c06vgkgzjlgo +sports Nigeria vs Algeria: Mahrez last minute goal clip Super Eagles wings Manchester City forward Riyad Mahrez score last minute free-kick to help Algeria defeat Nigeria 2-1 to progress to di final of dis year Africa Cup of Nations. Di goal from Mahrez prove to be virtually di last kick of di game as di near 7000 Algeria fans wey dey di stadium begin jubilate dia team win. Algeria take di lead for di first half thanks to Nigeria defender William Troost-Ekong own goal as im mistakenly convert Riyad Mahrez cross into im own net. Ighalo later equalise for Nigeria for di 72nd minute after im score penarity with di help of VAR. Di Desert Foxes control di most part of di game and even hit di bar late on as Nigeria no really create enough chances for di match. With di victory, Algeria go play Senegal for di final of dis year Africa Cup of Nations on Friday, 19 July. Meanwhile Nigeria go face Tunisia on Wednesday, 17 July for di third place match. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48984200 +sports Nigeria go play Zambia for Wafcon Bronze medal match Zambia and Nigeria go play each oda for di bronze medal match for di Women Africa Cup of Nations competition for Morocco. Di two lose dia semi-final matches on Monday. Zambia lose 1-0 to South Africa while defending champions Nigeria lose 5-4 on penalties to Morocco afta di game end 1-1 for extra time. Di two teams don already qualify for di 2023 FIFA Women’s World Cup for Australia and New Zealand. Defending champions Nigeria go make changes for dia Bronze match against ZZambia. Afta two players from dia starting line up chop red card for dia semi-final match against Morocco. Di two players wey collect red card na Halimatu Ayinde and Rasheedat Ajibade. Ayinde collect red card for di 48th minute afta one dangerous tackle on a Moroccan player. And for 70th minute Ajibade too chop red for anoda bad tackle. Meanwhile Zambia coach Bruce Mwape say im team go perform well for dia third place playoff match. Di game go shele for Mohammed V Sports Complex for Casablanca. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c1re7zdz5j0o +business Wike: VAT palava and di oda times di govnor of Rivers state don challenge Nigerian goment "Govnor Nyesom Wike, Rivers state govnor action to stop Nigeria goment from collecting Value Added Tax (VAT) through a court Judgment don set di pace for oda states for di kontri. Justice Stephen Pam of di Federal High Court for Port Harcourt say na di constitutional role of state goments to collect VAT and no be Federal Inland Revenue Service (FIRS). Justice Pam for e ruling on di FIRS application for a stay of execution say: ""to grant di order go negate di principle of equity"". Dis decision of di court don set di pace for oda states to directly collect VAT rather dan leave am for di federal goment. But di federal goment of Nigeria say dem don file appeal against di court judgement wey go allow states to collect Value Added Tax (VAT). Matthew Gbonjubola, Group Lead Special Taxation Federal Inland Revenue Service (FIRS) for press conference wit tori pipo for Abuja say to get a single tax authority wey dey manage taxing system go stop di challenge of double taxation. ""I fit confam to you say, we don file appeal for di appellate court against di judgement at di lower court for di Appeal Court for Rivers state,"" e tok. As tori of di court judgement wey give power to states to collect di Value Added Tax dey land, di Lagos State House of Assembly don shaparly passed di State Value Added Tax (VAT) bill. Speaker of di house, Mudashiru Obasa don also direct di acting alerk of to transmit di bill to Governor Babajide Sanwo-Olu, for assent. Di lawmakers pass di bill afta unanimous vote. Di speaker describe di bill as ""historic"". Rivers state govnor Nyesom Wike dey popular for challenging Nigeria goment especially on policies wey e feel say dey unconstitutional. Since becoming govnor for 2015 Wike don take strong position about federal goment actions for court and out of court. Di issue of tax deductions by federal goment na di first time Rivers state goment dey carry Nigeria goment go court - dat na for 2020. But for February, 2020 Govnor Wike threaten to drag di Federal goment to court over dia plan to withdraw money from di Excess Crude Account, to fund di military. Di govnor during im meeting wit di Emir of Kano, Alhaji Aminu Ado Bayero for Government House, Port Harcourt say, im no go support di plan for a fresh withdrawal except dem give Rivers State 13 percent share from di account. Also, for May 2020, e say Rivers State goment don commence documentation to sue Federal goment for ""unilateral"" withdrawal of N11billion from di Federation Accounts for the Nigerian Police. ""Our lawyers go prepare our papers and we go go court. Nobody say you no fit support di police, but you must get di consent of states before taking dia money,"" Govnor Wike tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58504991 +entertainment Grammy nominations 2022: Wizkid get Grammy nomination wit Burnaboy, Tems, Made, Femi Kuti "Wizkid, Burnaboy, Tems, Made and Femi Kuti na Nigerian musicians wey dey among oda Africa artists wey grab 2022 Grammy nominations. Di 2022 Grammy Awards show, wey dey officially known as di 64th Grammy Awards go shelle on Monday, January 31, 2022. Among di Nigerian artist, Wizkid and Femi Kuti get two nominations wey be; Best Global Music Album and Best Global Music Performance. For di category of Best Global Music Performance, artist wey dey di list na; Arooj Aftab, Angelique Kidjo, Burnaboy, Femi Kuti, Yo-Yo Ma and Wizkid ft Tems. While for di Best Global Music Album di musicians wey dem nominate na; Rocky Dawuni, Angelique Kidjo, Femi Kuti, Made Kuti and Wizkid. Nigerians for social media don begin dey send dia congratulations in advance to Wizkid afta tweets of im nomination come out. Wizkid Made in Lagos Deluxe edition get nominated for di ""Best Global Music Album"". While e song with Tems, Essence get nominated for ""Best Global Music Performance"" Dis ""Best Global Music Performance na di same category wey Burna Boy win last year. Tems wey her real name na Temilade Openiyi, na Nigerian singer, songwriter and producer. Dem born Tems for July 23, 1996. Raised by her mama, she start her own music production at di age of 20. She bin study Economics for one University in South Africa. Dis na afta she attend Dowen College for Lagos. Tems don release plenty singles and features wit Nigerian and international acts. Di young musician wey be strong listener of Aṣa, Adele, Lojay, and Zinloeesky songs, no feel like a new comer for dis music game., according to one BET report. On August 31, 2021, di Nigerian singer become BET Amplified Artist of The Month of August 2021. Burna Boy wey e real name na Damini Ogulu, na Nigerian singer, rapper songwriter and record label executive. Dem born Burna Boy on di 2nd of July, 1991 for Port Harcourt city, Nigeria. E be di only son and eldest of three children to Bosede and Samuel Ogulu. Burna search for knowledge take am outside Nigeria go United Kingdom to study Media Technology for University of Sussex (2008–2009) and Oxford Brookes University (2009–2010) to study Media Communications and Culture. Burna Boy don release series of EPs, singles, mixtapes, and albums including e 2018 extraordinary “Outside”. On Sunday, 14, March, Burna boy win im first ever Grammy under di ‘Best Global Music Album’ category for im ‘Twice As Tall‘ 2020 project during di 2021 Grammy Awards. Meanwhile for di 2022 Grammy nomination list, Burna collabo with Angelique Kidjo 'Do Yourself' dey among those wey dem nominate for Best Global Music Performance. Wizkid wey e real name na Ayodeji Ibrahim Balogun, na Nigerian singer and songwriter. E dey also know as Wizzy or Starboy and na one of Africa biggest artistes. Wizkid begin began recording music for very young age and manage to release one collaborative album with di Glorious Five one group wey im and some couple of e church friends formed. E rise to dey popular afta e release ""Holla at Your Boy"", di lead single from im debut studio album Superstar for (2011). ""Tease Me/Bad Guys"", ""Don't Dull"", ""Love My Baby"", ""Pakurumo"" and ""Oluwa Lo Ni"" na also part of wetin im release as singles from di Superstar album. For 2016, Wizkid achieve international recognition afta e collaboration with Drake for di global hit, ""One Dance"". For In 2019, e feature for Beyoncé project Di Lion King: di Gift for di collaboration ""Brown Skin Girl"", wey make am win Grammy Award for Best Music Video. Femi Kuti, na son of di late, legendary musician Fela Kuti. Before Femi become im own bandleader, e start to dey play saxophone for e father band, Egypt 80, for 1979 where e learn everi-everi about performing with a legend. For 1986, Femi create im own band wey dem cal Positive Force, and e quickly dey popular as strong group for Afrobeat music. Femi don perform for some of di world most ogbonge stages and festivals, and collaborate with big musicians for different genres. E get two nominations for di 2022 Grammy; im song Pà Pá Pà dey for di list of Best Global Music Performance while e Album Legacy + dey Best Global Music Album list. Made Kuti na Fela grandson and Femi son. E grow up for di New Afrika Shrine inside Lagos, according to informate for e website. E study for Trinity Laban Conservatoire inside London and don play for Femi Positive Force band from wey e dey young age. Made Kuti new album 'For(e)ward' - wey come out February 5, 2021 - na modern and progressive freedom manifesto, wey dey push di boundaries of Afro Made and e papa Femi Kuti album titled 'Lagacy +' dey nominated for Best Global Music Album category for di 2022 Grammy." https://www.bbc.com/pidgin/media-59394925 +entertainment Don Jazzy married: Michelle Jackson, Don Jazzy former wife don react to dia marriage "Michelle Jackson don react for di first time about her marriage to ogbonge Nigerian music producer Don Jazzy. For message wey she post for social media she say: ""thank you Don Jazzy for your kind expressions."" On Saturday di Ogbonge producer bin announce to im fans say im bin marry at di age of 20 but di marriage end for divorce wen e be 22 years because of im love for music wey no make am give im best for di marriage. Di revelation bin shock many Nigerians. Michelle wey dey based for UK use her post to thank pipo wey show her love with beautiful messages but she add say ""my inbox dey full right now."" Oda tins she tok about na her family she thank her wonderful friends and family wey dey loyal all dis years. She end di post wit one love. According to informate ontop her Instagram page, Michelle Jackson na Model and Writer. She also be Hair, Beauty and Fashion Brand Ambassador wey based in di UK. Michelle bio also reveal say she get interest in knitting and crocheting." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56633750 +entertainment Grammy winners 2021: Davido react to Burna Boy and Wizkid win for di 63rd annual ceremony "Nigerian Afrobeat singer Davido don react to Burna Boy and Wizkid Grammy award win. Burna Boy win di Best Global Music Album category while Wizkid win di Best Music Video for im song wit Beyoncé; Brown Skin Girl, from Lion King: The Gift album. Dis na di first time dis two musicians go win di ogbonge music award. For inside tweet, Davido say ""Whichever way you look am, dis na victory for Nigeria for di culture and di pipo.."" Di singer wey no collect any Grammy nomination add say congrats to our winners! Tule Naija wit emoji of Nigeria flag. Di 63rd Grammy Awards happun for Los Angeles United States of America on Sunday night March 14." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56398701 +sports Istanbul başakşehir vs Man United: See Wetin happun to Solskjaer afta United lose 2-1 for Champions League "Dis no be good time for Manchester United fans as dia team lose again, dis time na to Istanbul başakşehir dem lose 2-1 on Wednesday night for Champions League. Di Reds fail to extend dia unbeaten record dis season for Champions League campaign, with defeat to di Turkish club. Former Chelsea man Demba Ba and Edin Visca score for di hosts for first half, while Anthony Martial score United only goal for di match. United form dis season for Premier League get as e be, last month Tottenham flog dem 6-1 for dia house, but dem recover to win three of di next four games, wey include draw against Chelsea. But afta Sunday poor performance against Arsenal wey dem lose 1-0 for Old Trafford and anoda weak performance for Istanbul, di back-to-back defeats dey put pressure on di boss Solskjaer. United neva win dia last six games for house for league, while defeat by Basaksehir end dia run of 10 straight wins for road. Even though di international break dey near, Van Persie say im no be ""big fan of sacking coaches"", while ex-United midfielder Owen Hargreaves say Saturday game against Everton na""huge game""." https://www.bbc.com/pidgin/sport-54821435 +sports Turkey vs Italy: Ciro Immobile, Lorenzo Insigne goals fire Italy to opening day victory over Turkey Euro 2020 start in spectacular fashion as Italy begin di tournament wit solid start in front of their own fans as dem comfortably beat Turkey 3-0. Own goal by Merih Demiral and goals from Ciro Immobile and Lorenzo Insigne settle di one-sided Group A match - di first of 51 fixtures wey go take place for 11 European cities over di next month. For di first time for single game for di European Championship, Italy score three times, Roberto Mancini's side register 24 attempts as dem change am for Turkey to extend dia unbeaten run to 28 matches wey start far back as September 2018. Italy dominate di first half but struggle to find di net as Giorgio Chiellini produce fine save from Turkey goalkeeper Ugurcan Cakir. Di biggest football competition for Europe start on Friday afta dem bin delay am for ova a year sake of coronavirus pandemic. Na for Rome Stadio Olimpico wey get ova 70,000 capacity dem go do di opening ceremony but di organisers only allow 25% spectators for inside di stadium. Fans don already begin dey rep dia team ahead of di opening match wey go see Italy face Turkey. Some of dem wear dia Jersey and paint dia face wit dia national team colours Italian tenor Andrea Bocelli sing di iconic 'Nessun Dorma' song, dem bin use am as di official anthem of Italia '90. Oda artist wey perform na Martin Garrix, Bono and The Edge, dem perform di official song of di tournament, 'We Are The People'. Di effizy and packaging of di opening ceremony really totori fans. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57448079 +health Coronavirus tips: How WHO say make we use face mask sake of COVID-19 outbreak As di coronavirus pandemic continue to dey spread for di world, state goments for different kontris don order compulsory use of facemask as measure to slow down di spread of di Covid-19 disease. Although di World Health Organization tok say na only health workers, pipo wey dey treat Covid- 19 patients and pipo wey sick suppose dey wear facemask. Di health join bodiinsist say pipo wey well no need use facemask. However, scientists for all ova di world say e no bad if evribodi begin dey use am as e dey safer to use, pass wen di face no dey covered wit mask for dis coronavirus period. Di World Health Organization advise say if you wan use facemask, den you must sabi how dem dey wear am and how you go fit troway am properly. Di health body show five ways how you fit use facemask wey go work. Lagos and Osun states, south west Nigeria don become di latest states for di world to make am compulsory for use of face mask for all dia residents before dem enta public space. Di states follow afta Germany, Republic of Czech, Australia, Morocco, Turkey, Slovakia, Poland, Jamaica, Bosnia and Herzegovina wey don give order say make nobody comot for house witout facemask. Even di Nigeria Presidential Taskforce on Covid- 19 for one of di recent media briefing bin encourage all kontri pipo to begin dey use facemask if dey wan comot for house. According to di latest data wey di Nigeria Centre for Disease Control release for 24 April, di kontri get 1, 182 confamed cases of coronavirus, 35 deaths and 222 don dey discharged. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52430451 +politics Sowore Revolution Now Protest: Foto, videos, hot tori as e dey happun on August 5 across Nigeria "#RevolutionNow protesters say 'wetin dem see on Monday for Lagos only happun during di time wey di late General Sani Abacha rule for Nigeria. Security pipo enta streets fire tear gas, check pipo phones, arrests di ones dem fit arrest, for Lagos, South West Nigeria as supporters of di Revolution Now protest for Nigeria say dem go still go ahead wit dia protest. Tori be say goment arrest di main organiser for weekend. Tok tok pesin for DSS say dem detain Omoyele Sowore sake of im wan ""overthrow di Nigeria goment."" Di protest na against bad goment inside Nigeria. Di Revolution Now suppose happun inside 21 states of di 36 states wey dey Nigeria. Nigeria spy secret police Department of State Security Service (DSS), don confam say na dem true-true arrest di former Presidential candidate of African Action Congress, Omoyele Sowore. Di protesters for Lagos tell BBC for afternoon say di protest go continue on Tuesday for Ojota. Di Nigerian Police don call di protest across di kontri on August 5, 2019 treasonable offence. Di revolution protest no hold for Nigeria capital Abuja as di popular Unity Fountain dey empty. Police officers dey ground to chook eye for wetin dey happun. Di early mor mor rain sef don contribute to prevent pipo to come out for di protest. One of di pipo wey dey collabo di #RevolutionNow protest Solomon Lenu tell BBC Pidgin say dem no fit continue wit di protest for for Port Harcourt, Southern Nigeria, because police don clamp down everi where and no gree allow dem do di protest. Im say dem still dey try to see how dem fit tok to police to see reasons why dem suppose allow dem. ""As e stand now, plenti tension dey di state and di goment don fully mobilise security pipo to clamp down on dis movement and we no go wan put di lives of di pipo wey dey protest for danger so as e dey now e no dey possible for us to continue with di protest as di security dey mobilise to stand against us. Even though we still dey try to see how we fit reachbout to di police hierarchy to see how dem for allow us continue with dis movement because na for di good of evribodi."" Lenu say wetin dem go demand for if dem allow dem do di protest na for di unconditional release of di convener of di #RevolutionNow protest, Omoyele Sowore and all di demands wey di #RevolutionNow protest dey ask. Solomon Lenu na di President for Excellent Achievers Movement and tok tok pesin for Renaissance for Peace and Empowerment Initiative wey dey partner with di #RevolutionNow protest to organise di protest for Port Harcourt as dem believe in di Ideology of di protest A drive round di city of Port Harcourt show say pipo dey go about dia normal business. Kano protest : Na same thing for Kano as no single protester show face for Di usual meeting point of Sani Abacha Stadium for Di state.BBC Pidgin go round the city but na normal activity dey happun without even strong police or military presence Since wey dem arrest Sowore, na so many ogbonge Nigerians dey condemn di move, some don say di protest must go on, but who be dis man wey dey dinger Revolution Now across Nigeria? Nigeria president Muhammadu Buhari say make all di pipo wey dey sponsor di 'RevolutionNow protest' show dia face and lead di protest. Oda Nigerians para for di mata" https://www.bbc.com/pidgin/tori-49235344 +sports Everton v Wolves: Iwobi tear net again as Everton win 3-2 Nigerian forward Alex Iwobi score di second goal for Everton as dem win 3-2 against Wolves for Premier League. Iwobi wey join di team dis summer, score wit im head for first half to make am 2-1 for im club afta Romain Saiss bin equalize Richarlison goal. Dis na di second goal Iwobi dey score dis week, afta im bin score for dia 4-2 win against Lincoln Town for Carabao Cup. Iwobi later comot for di game for second half as e look like say im get injury. Why e neva clear weda di injury serious or not, e no go be good tori for coach Gernot Rohr as Super Eagles get friendly game against Ukraine wey dey come. Di Super Eagles player join Everton from Arsenal for deal wey fit rise reach £34 million for August dis year. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49543594 +sports Chineme Martins: Wetin you suppose know about di Nassarawa Utd player wey die for pitch "Nigeria Football Federation and di League Management Company dey mourn di death of Nasarawa United defender Chineme Martins wey die during dia league match against Katsina United for Lafia on Sunday. For inside statement LMC chairman, Shehu Dikko, tell di late player family and im club sorry. Im add say ""LMC expect to get standard autopsy to find out di cause of di player death. Di Nigeria football federation say dem dey sad about di player death. Tori be say Martins collapse for inside di 43 minute of di match and medical officers from di two clubs attend to am for pitch before dem rush am go Dalhatu Araf Specialist Hospital, Lafia wia dem confam say im don die. Nasarawa United go on to win di match 3-0, Chinedum Ohanachom score hat trick for di game. Di result mean say dem dey 13 position for table with 28 points." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51798846 +entertainment BBNaija news now: Ozo and Trikytee don chop eviction from Big brother Naija lockdown house Trikytee and Ozo na di last set of housemates to leave di Big Brother Naija season 5 lockdown edition before di Grande finale. Dem bin dey up for eviction dis week wit two oda housemates afta Biggie introduce new twist of nomination to di show. Out of di four housemates, Laycon Ozo, Dorathy and Trikytee, wey dey up for eviction dis week, Trikytee and Ozo na im get di lowest votes from fans. Nengi, Neo, Vee, Laycon and Dorathy na di housemates wey go remain for di house till day 71 . As e be, 15 housemates out of 20 don carry dia load comot- Lilo, Ka3na, Eric, Tochi, Kaisha, Praise, Wathoni, Tolanibaj, Bighto, Lucy, Prince Kiddwaya, Trickytee, Ozo while Erica bin chop disqualification afta she break Big Brother house rules. Afta di eviction, Triky follow Ebuka tok say e no dey shocking for am, although im bin dey hopeful say im no go comot dis week. Trikytee don dey up for eviction ova three times since dem start di show but housemates dey always save am. Di moment Ebuka call Ozo as di next housemate to leave di Big brother show. Nengi wey bin earlier refer to Ozo as her closest friend for di house, cry afta im comot Ozo say e get something about Nengi wey make am wan dey closer to her. Before im comot, e thank im papa and mama for supporting im vision. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54228569 +entertainment "Mr Macaroni Lekki Toll Gate: Debo Adedayo ""Mr Macaroni"" profile from Nigerian comedian to EndSARS activist" """Mr Macaroni you are doing well"" - Na di popular phrase Nigerians take sabi comedian Debo Adedayo AKA ""Mr Macaroni"" sake of im comedy skits wey get plenty followers on social media sake of how e dey reflect wetin dey happun for society. But im [Mr Macaroni] popularity increase much more afta police arrest am for di Lekki Toll Gate protest on 13 February, 2021 wen many young pipo bin plan one protest against plans to open di popular toll for Nigeria commercial city of Lagos. Tori be say, since di EndSARS protest against police brutality for Lagos Nigeria for October 2020, di name Mr Macaroni don blow pass as pipo bin take sabi am before. Di EndSARS di biggest protests wey Nigerian youths don eva organise to fight against police harassment and brutality, plus extrajudicial killings by di police branch, Special Anti-Robbery Squad (SARS). Now na who be Debo Adedayo AKA ""Mr Macaroni""? Kack sharperly, read dis tori till di end to sabi some interesting tins about dis Nigerian comedian turn EndSARS activist State of Origin: Debo Adedayo na from Ogun state south west Nigeria, but I dey live for Lagos. Date of Birth: Dem born am on di May 3, 1992. Education: Mr Macaroni bin attend primary school for Tendercare International School, do secondary for Babcock University High School, come study theatre Arts and Film studies for Redeemer's University, Ede. Job: Im na di founder of Mr Macaroni Entertainment, registered company wey specialise for different kain of entertainment. Career: Oga Debo bin don start to dey do acting since in dey for primary school but na for 2012 e begin show for many feem and TV series. ""Mr Macaroni you are doing well"" skit: Na for 2019 im begin dey create content for online media, come begin dey popular for im comedy acting as typical sugar daddy for Nigeria." https://www.bbc.com/pidgin/media-56067641 +health Covid-19 cases in Ghana: Police arrest over 200 people sake of dem no wear nose masks in public "Police for Ghana arrest a total of 202 people who fail to wear nose masks contrary to directive by Prez Akufo-Addo to citizens in de fight against Covid-19. De Accra Regional Police Command mount special operation for town during which dem arrest 97 people, while de Police for Industrial City, Tema also pick up some 105 people who no wear dema nose masks in public. DSP Afia Tenge, Accra Regional Police PRO talk say, ""De Regional Police Command go on special operation dis morning wey we arrest 97 people who no dey wear dema face masks."" ""We arrest dem around places like Tudu, railways, CMB den Farisco areas."" Ghana Police say dem realise say people get de facemask some but dem no dey wear am. Police Officials for Ghana say dem go interrogate and screen de suspects after which dem go take further action on dem for flouting de Covid-19 protocols. President Akufo-Addo, in en 22nd address to Ghanaians on Covid-19 order Inspector General of Police, James Oppong-Boanuh say dem for ensure de strict enforcement of de mandatory wearing of nose masks." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55745151 +politics Biden tell Japan say e ready to use force defend Taiwan "U.S. President Joe Biden say on Monday say im ready to use force to defend Taiwan. Biden tok dis one as part of series of critical comments about China, during im visit to Japan. Na im first trip to Japan since im enta office and no so Japanese Prime Minister Fumio Kishida stand dia dey look. But one of im aide say di comment no mean say U.S. policy on di self-ruled island don change. Di US president comment appear to dey different from existing U.S. policy of so-called strategic ambiguity on Taiwan. China consider di democratic island as dia territory, part of ""one China"". And Beijing say na di most sensitive and important issue for dia relationship wit di United States. Wen one reporter ask Biden if United States go defend Taiwan if dem attack am, di president answer: ""Yes."" ""Dat na di commitment wey we make,"" Joe Biden say, during one joint news conference wit di Japanese leader. ""We agree wit one-China policy. We don sign am plus all di intended agreements wey dem make inside. ""But di idea say, dem fit to take am by force, just take am by force, no just dey, no just dey appropriate."" Im add say im dey expect say dat kain tin no go happun or dey attempted. Following Biden comments, one White House official say e no get any change for policy towards Taiwan. Di president national security aides shift for dia seats and bend dia heads, dey study Biden closely as im respond to di question on Taiwan. Plenti bin look down as im make wetin resemble not so clear commitment to Taiwan defence. Biden make similar comment about defending Taiwan for October. During dat time, one White House tok tok pesin say Biden bin no dey announce any change in U.S. policy. And one analyst refer to di comment as ""gaffe"" or blunder. United States bin don agree long ago say na one China, including Taiwan. But it e don adopt im ""strategic ambiguity"" on di question of weda e go involve imsef in military conflict over di island. Di tok dey come as Biden make tough comments about China increasingly self-confident for di region. Di president say im hope say Russia President Vladimir Putin go pay price for im invasion of Ukraine in part to show China wetin e go face if e invade Taiwan. Di comments dey likely to both provoke Beijing and overshadow di koko of Biden Japan visit, wey be to achieve one Indo-Pacific Economic Framework. Di framework be broad plan wey go provide economic pillar for U.S. engagement with Asia. Im trip include meetings wit di leaders of Japan, India and Australia, for di ""Quad"" group of kontris." https://www.bbc.com/pidgin/61550191 +politics UK prime minister: Boris Johnson fit really return as UK prime minister? "Boris Johnson, di man wey dem remove as UK prime minister by im own goment just three months ago, don emerge as one of di main pipo to become di next prime minister. Im replacement, Liz Truss crash out 45 days in di job, announcing her resignation afta dem force her to drop most of her policy programme afta e affect financial markets. Oga Johnson bin win di 2019 general election - and under di British constitution di party wey dey power fit change leader without anoda election. Na Conservative Party members elect Truss, wey fit get di final say for dis latest contest, if two contenders remain afta MP don vote. Johnson second premiership go be extraordinary turnaround even for politician wey don make miraculous comebacks before. Di last time anybody return to office of prime minister afta losing di leadership of dia party na 140 years ago wen William Gladstone return to lead di Liberals, although some party leaders don do two times as prime minister, including Sir Winston Churchill and Harold Wilson. E no dey certain say Johnson go contest - e neva make up im mind, dem tell us. Though according to im papa Stanley, di former prime minister fit dey on im way back to di UK from holiday for Dominican Republic. Will Walden, a former press secretary for Johnson, tell Sky News say Johnson dey ""clearly take wetin im dey hear"" on a leadership bid. For im final appearance for Prime Minister Questions, Johnson sign off with ""hasta la vista, baby"". E drop hint say im neva finish im work - e use anoda catchphrase from di Terminator films: ""I'll be back."" One of im most loyal supporters, Business Secretary Jacob Rees-Mogg don launch social media campaign to get am back into Downing Street, and plenty Conservative MPs dey support am. Defence Secretary Ben Wallace, wey pipo see as as influential force for di Conservative party, tell di im dey ""lean towards"" supporting Johnson. Party rules for di leadership contest mean hopefuls need di backing of at least 100 Tory MPs by Monday afternoon to still dey in di race. Ordinarily, dis one no be easy tin for a man wey get 148 of im colleagues vote against am for confidence vote in June - wey almost 60 ministers resign one month later. Plenty accusations happun for di final months of oga Johnson time for office say e break ministerial rules by lying about Covid lockdown-busting parties for Downing Street. E still dey under investigation by di Parliamentary Standards Committee, wey fit make dem suspend am from di Parliament, or even remove am as MP. Some series of scandals and questions of personal conduct bring down Johnson. E possible say MPs wey no gree support am six weeks ago fit accept am now? Tory MP Sir Roger Gale don tok say im go resign as di party whip if Johnson get vote back as prime minister. Foreign Office Minister Jesse Norman, a former friend of oga Johnson, say ""choosing Boris now go be an absolutely catastrophic decision"". Im Tory colleague Crispin Blunt don also publicly argue say Johnson no be pesin to restore di reputation of di Conservative Party. Opposition parties don also bin quick to condemn suggestions say Mr Johnson fit make a comeback. Opposition party no like di idea of Johnson return Labour leader Sir Keir Starmer say di former prime minister dey ""unfit for office"". Scotland Frist Minister Nicola Sturgeon describe Johnson return as ""ridiculous suggestion"". Liberal Democrats wey dey attempt to block Johnson becoming prime minister through motion for parliament describe di former UK prime minister as ""Britain's Berlusconi"". Oga Johnson don surprisingly keep low profile since leaving office. E no dey too tok for di House of Commons and spend di past few weeks doing speaking tour of di US before going on holiday. But Johnson biographer Andrew Gimson point out say di man no be pesin to ""live a life of blameless obscurity"". If only single candidate emerge, di contest go dey over on Monday - if not, dem go chose di new leader by a vote from party membership on Friday 28 October. Survey dem do in di final days of Liz Truss' premiership don continue to show Johnson as di most popular successor. Patrick English, Associate Director of polling company YouGov, say di Conservative party dey find ""pesin wey fit provide unity and pull di party back togeda and compete again (Labour leader) Keir Starmer. ""If you ask di members who dat pesin be - na Boris Johnson,"" oga English tok. ""If oga Johnson enta di final two, e get advantage."" A Boris Johnson candidacy go also work in favour of oda candidates, according to oga English. Rishi Sunak and Penny Mordaunt, wey contest to replace am, be like pipo wey go re-contest. ""I tink if we dey tok about unity and decisive candidates oga Sunak and oga Johnson na di two pipo wey fit divide di party,"" oga Johnson tok." https://www.bbc.com/pidgin/world-63349835 +sports Champions League draw: UCL fixtures go see Messi and Ronaldo for group stage face each oda Two of di best players for modern football go clash for di Champions League group stage dis season afta Juventus draw inside same group wit Barcelona. Premier League champions Liverpool go also face Ajax, as Chelsea dey di same group wit Europa League winners Sevilla, while Manchester City go face Porto. Manchester United dey drawn against Paris St-Germain, wey dem knock out in di last 16 for di 2018-19 season. Meanwhile Cristiano Ronaldo and Lionel Messi go face each other after Juventus and Barcelona find demsef for di same group: Group G. Di draw for Geneva dey happun without club officials for dia due to di ongoing coronavirus pandemic. Dis year group stage go start on Tuesday, 20 October while di final na on Saturday, 29 May 2021 for di Ataturk Stadium in Istanbul. Group A Group B Group C Group D Group E Group F Group G Group H https://www.bbc.com/pidgin/sport-54377049 +entertainment Ooni of Ife wife give birth to son: Prophetess Naomi give birth to boy - See wetin di arrival of di prince mean to di Royal throne of Oduduwa Ooni of Ife, Ọba Enitan Adeyeye Ogunwusi don announce say, im wife, Prophetess Naomi, Olori Silekunola don born son - prince in to di Royal throne of Oduduwa. E post ontop im Facebook page on Wednesday morning to confam di tori say im wife don born di Prince to di royal throne. He also confam say mother and child dey do well. Some months ago, tori bin dey fly upandan say di Yoruba king and im wife, bin welcome a new baby as pipo bin don dey suggest say im new wife get belle. But as e be, di King just announce di birth of im son on Wednesday. Dis new born son go be di heir to di throne of di royal Ife palace. To be prince of Oduduwa mean to become one of di most important pesin for Yoruba kingdom. Di prince of Oduduwa get chance to become a king for Ile-Ife. To be king of Ile-Ife mean say you fit lay claim to di throne of Oduduwa, who dem consider as di first king and most important king of Yoruba land. Di new prince na di first son of Oba Adeyeye Ogunwusi , di 51st and current traditional ruler of di Yoruba Kingdom of Ile-Ife. Im fit become di 52nd King of Ile-Ife. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54985853 +sports Anthony Joshua: Downfall of man no be end of im life - Buhari "Na plenti hailing Nigeria Presido Muhammadu Buhari cari reach di domot of World Heavyweight Boxing Champion, Anthony Joshua. Presido Buhari say, ""of a truth, di downfall of a man no be di end of im life, anyhow way must to dey."" Oga Buhari, tuale Anthony Joshua, for bringing joy to millions of Naija pipo for home and diaspora wey bin support am to regain im titles wey in lose to Ruiz six months ago. Im add say, dis na lesson wey evri pesin ""must all learn"" from Joshua as a kontri. Di British born Nigeria collect back all im belts for saturday rematch wey im do Mexico-American Andy Ruiz jnr." https://www.bbc.com/pidgin/media-50704536 +entertainment Is Seyi Shay married?: Look wetin we know about Seyi Shay engagement as singer reveal pregnancy for new music video "Nigeria singer Seyi Shay shock fans as she reveal pregnancy for new music album, Big girl. Di Album wey feature her journey for di music industry, her love life and wia she dey now don dey trend for social media since di release. Fans don also dey ask if di former Nigerian idol judge don marry. Well, she neva marry but ring dey her finger. Seyi Shay team confam am to BBC Pidgin say she don engage. Although dem no confam to us who she dey engaged to but she bin first tok am for one interview wit tori pipo for Beat FM earlier dis year say. Di reporters bin spot her wearing an engagement ring and wen dem ask her about am, she confam she don dey engaged. ""Some guy give am to me and im ask would you marry me?"", she tok. Dis na real diamonds, she add as she show off di ring. Meanwhile fans don enta social media to congratulate her. Seyi Shay real name na Deborah Oluwaseyi Joshua Odedere. She be Nigerian based singer, song writer, recording artist and performer. Her song Seyi or Shay wey she release for 2015 blow her into limelight. Dem born her for Dec 21 1985 for Tottenham, London England and she be di last born. Her mama na from Northern Nigeria and her papa na from di western part of di kontri. Seyi attend Command High School, Maryland, Lagos for her secondary school education. she later go London for her undergraduate studies. Firstly, she attend one local UK college where she studied music, then move go di University of East London, where she get degree in Business Management. Shay sign her first record deal with No Apology. For 2006, she form girl Band, Boadicea. Di band scata for 2008. Hit songs like Right Now, Yolo Yolo, Gimme Love, Irawo, make her popular. Nigerian Idol bin reveal her as one of di judges wey go dey for di 2021 show. She later comot from di show sake of oda project wey she say she get and also sake of her pregnancy, her team confam to BBC." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60358747 +entertainment BBNaija update: Liquorose cry, Maria tackle Pere, Angel and Yousef plus oda drama wey happun afta Saturday night party "Di Saturday night party na one of di main part of di Big Brother Naija [BBNaija] show wey Housemates and audiences dey always look forward to. Di second Saturday night party for di 'Shine Ya Eye' 2021 edition see how most of di Housemates high from plenty alcohol. Saskay, Cross, Liquorose, Angel, JayPaul, Maria, Beatrice, Boma and Princess no fit hide dia highness. Liquorose breakdown in tears afta di party as fellow Housemates Tega and Jackie B try to console her inside toilet wia she dey cry. ""I just dey emotional because I miss my dad. I go make you proud daddy, I promise you. Don't worry I'm fine. Na just say I dey in my feelings tonight,"" Liquorose tell di housemates. 29 year old Maria and Pere na two housemates wey audiences dey monitor dia attitude toward dem sef for di House as dem dey look say something fit develop between dem. Earlier dis week, na gbas gbos between di two wen Maria ""serve"" Pere breakfast wia she tell am say she no like di ex-US Marine. But di gbas gbos continue afta di Saturday night party wen Pere tell Maria say im no want anything wit her inside Big Brother house. Dis na afta Maria confront am about im attitude for di party and why Pere ignore her afta di party. ""Why you dey give me a attitude, you want make we make out for national TV or to tell you say I Love You on a national TV? What do you want from me? Not even friendship?"" Maria ask Pere wey say im no want anything. Afta di Saturday might party, one of di housemates Princess say she for no like sleep alone. ""I no go get cute guys for dis house make I come dey sleep alone,"" Princess play-play tok her mind. From di beginning of di party, till e end, Saga hold tight to Nini - even as di party close we see di housemates wey be like say dem wan start relationship for di Big Brother house dey get along well. Also, e remain small make Boma no sleep for im Head of House room. Na Peace di head of house e hold tight and dey wit afta di Saturday night party before Jackie B carry am go di HoH room to sleep. Today na eviction night and one between Yerins, Beatrice, Whitemoney, Yousef and Niyi wey dey u for eviction go-go house today." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58132126 +entertainment One woman die afta she injure for Asake concert "One woman don die afta dem injure for one crush for a gig for London Brixton O2 Academy wey leave many pipo hurt. Dem bin abandon di concert, by Afro-pop singer Asake, part-way through. as ""large number of pipo"" try to force dia way inside on Thursday, Met Police tok. Rebecca Ikumelo dey among pipo wey injure and she die for hospital on Saturday morning, according to wetin Met police tok. Di 33-year-old na from Newham for east London, officers add. Two oda women aged 21 and 23 still remain in critical condition, police tok. Three people bin dey critical condition afta dem injure for di gig. Social media footage show pipo dey scream, shout and struggle. One witness tok say about 1,000 pipo turn up for di event without tickets. One of di crush victims tell BBC: ""I no fit breathe and I completely faint. I bin tink say I don die."" Di woman wey dem later carry go hospital as dem suspect internal bleeding, say: ""I take my last breath and I no fit breathe again. Fear catch me."" Di woman, wey follow BBC tok afta dem discharge her from hospital, say: ""I bin dey queue to give dem my ticket but pipo too plenty outside, na mad crowd and before you know, dem begin push, I just fall down.” ""I bin dey try stand up but pipo just dey step my head and march my body. More dan 10 pipo dey on top of  me.” ""One man pull me up and wen I wake up I see say I dey di back of ambulance."" Di woman wey come from Battersea for south London, suffer skinned knees and black eye. She say di tin wey happun still dey surprise her. ""I just thank God say I escape, my bones no break, dem tink say I get internal bleeding but thank God , I do GT scan and di scan say I dey alright. For inside video wey spread for social media, e show as crowd full ground from di road reach di door venue, as pipo dey scream, shout plus struggle. One video wey pesin take from outside di Academy show crowd of pipo for di street and one woman dey shout say dem dey push pipo. One 35 year old man, Akin Oluwaleimu, from Kirby Cross near Colchester wit im 14 year old daughter bin go di concert but dem decide to go back home as tins turn rowdy and pipo begin dey push themselves. ""We bin try find out wetin dey occur and dem tell us say dem don close door and dem no go gree make pipo enta. ""Some pipo tok say dem dey find pipo wey dey hide; some oda pipo say pipo dey come and dem no hold tickets. ""Police bin come between about 9:30pm and 10pm and dat na wen everytin come even worse. ""We no enta. Na wen we dey comot dem tell us say dem don stop di show. ""Two ladies faint and dem carry dem comot. Pipo injure sake of di stampede, di pushing too much. ""I no too worry about myself like dat but I worry about my daughter safety."" Anoda witness, Jay Taylor, wey be 24 years old from Greenwich, describe how some pipo, wey im sure say dem be fans wey no get ticket bin try force dia way enta di venue as organisers beg dem to stop. She say: ""Pipo begin jump on each other and dem even jump on police. ""Di stampede start around dat kain five or 10 past 10. Up until that point, mata of safety no dey. I no understand wetin dey happun until I follow di venue organisers and di police tok. ""Wen I see say pipo begin rush go push di doors my first thought na: 'Yes, some pipo fit begin dey stab odas as dat kain tin dey occur wen plenty pipo gada, dem dey do stupid things.' Na dat time I comot."" One journalist and author Jason Okundaye, wey dey outside di venue at di time also tok say,  ""di Academy staff dey silent, dem no tok anytin. He add say im go house afta e observe dangerous conditions of di area: ""Outside di venue no dey safe at all, everywhere still dey slippery conditions sake of di snowstorm wey bin fall earlier, everywhere cold, di crowd dey confused and aggressive police dogs make di risk of huge crush dey likely."" Met Police say dem no use police dogs for di response. Di O2 Academy Brixton get standing capacity of nearly 5,000 pipo according to dia website. Di venue dey for di opposite of Brixton police station, wey explain di swift response on Thursday night. Plenty officers dey di scene and you fit see broken glass on di floor by di door to di venue. Under di ""sold out"" sign, metal railings wey scatter across di pavement bear testament to di chaotic scenes. Cdr Ade Adelekan from di Metropolitan Police say specialist officers go examine di scene as part of one investigation wey go dey ""as thorough and as forensic as necessary"". He say: ""Dis na extremely upsetting incident wey land four pipo for critical condition for hospital. My thoughts and prayers dey wit dem and dia families."" Met Police directorate of professional standards go view all material, including body-worn video footage from di officers for di scene, Scotland Yard tok. Mayor of London Sadiq Khan tweet say im dey ""heartbroken"", e add say: ""My thoughts dey wit all those wey dey affected by di awful incident for Brixton Academy."" For 1974, one 14-year-old David Cassidy fan die for di pop singer concert for di White City Stadium for London, and anoda 700 pipo injure. For di Monsters of Rock festival for 1988, two pipo lost dia lives for stampede as Guns 'N Roses play for di muddy Castle Donington for Leicestershire. Earlier dis year, Liverpool M&S Bank Arena - where next year Eurovision Song Contest go hold launch one investigation afta fans complain of overcrowding for one concert wey one local hero Jamie Webster organize although dem no report any injury. E don become common for artists to pause dia shows if dem suspect say problem fit dey wit di crowd, wit heightened awareness of such dangers for di wake of di tragedy for Travis Scott Astroworld festival, for Texas for November 2021, wey 10 pipo die. Dis na di third of three sold-out shows for di Academy wey di Nigerian singer wey pipo dey also Mr Money go do. For inside one statement on di artist Instagram account, Asake say: ""My heart dey wit those wey injure last night and get any form of discomfort. I pray make you get well soonest. ""I also dey di process of reaching out to individuals. I still neva get full informate from di venue management on wetin cause di kasala for di entrance of Brixton Academy, but we dey thankful say everyin bin dey peaceful for di end."" Asake, wey im real name na Ahmed Ololade, dey nominated for BBC Radio 1's Sound of 2023 award. Dem describe am on di venue website as ""one of di hottest breakout stars from Nigeria"" and e dey tour im debut album, Mr. Money wit di Vibe. Dem born and raise Asake for Lagos State, im songs na part of di Nigerian street-pop subgenre wey blends Afrobeats with Amapiano, pop melodies and street-smart rap lyrics. E bin get one breakout hit for 2020 wit im single, Lady." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cgld5jelzlko +sports West Brom and Nigeria Semi Ajayi say 'No dream dey too big' "Even though e miss out to play for Premier League with Arsenal, Semi Ajayi never ever lose confidence say e go make am one day. Instead, di 26-year-old Nigeria defender journey to di Premier League see am begin drop down to lower leagues in order to play regular football. But now im dey prepare to play for English top-flight with West Bromwich Albion wey just gain promotion. ""Always believe in your own ability,"" im tell BBC Sport. ""Never let anyone tell you say you neo fit make am or your dreams are too big. ""Look at me I bin dey League 1 just 18 months ago and now I dey ready to play for Premier League."" West Brom gain promotion when dem finish as runners-up for Championship and come begin dia Premier League campaign on Sunday against visiting Leicester City. London-born Ajayi begin im youth career for Charlton Athletic before e sign contract with senior team and come go non-league Dartford as loan player for one season. At di age of 20 e move go Arsenal and even though e play many friendlies dia and even come from bench to play many premier league matches, im still no get breakthrough. Instead dem loan am to Cardiff City, wia for 2015 e stay dia permanently, but then loan am again go AFC Wimbledon and then Crewe Alexandra. Again dem move am go Rotherham for League 1 - on temporary arrangement - and na from dia e shine for West Brom eye wey make dem sign am. He believes that his time playing at different levels has helped rather than hindered his career. E believe say di times im dey play for lower leagues no pour sand sand for im career garri. ""To experience different leagues and international football mean say you go always have to believe in your own ability,"" he explained. Ajayi don play 10 times for Nigeria so far and na small remain for am to join di final Super Eagles squad for last year Africa Cup of Nations for Egypt. ""E pain me say I miss out but I wished di boys all di best and I no take am personally,"" e tok. ""I just know say I suppose come back to show di kain pesin I be,"" E still get am for mind to win something with Nigeria. ""(I want to) win Afcon, e go dey amazing for Nigeria, and to play for World Cup and win am dat one join - why not?"" he hala. As for im first season for Premier League him wan play well wit West Brom team. ""We no come here to just come, we dey here to compete and show everybodi how good we be,"" he tok." https://www.bbc.com/pidgin/sport-54106951 +sports Chelsea: Roman Abramovich say e plan to sell club and 'donate proceeds to war victims' "Chelsea owner Roman Abramovich tok say im dey plan to sell di Premier League club. Di Russian billionaire for statement tok say e ''don take di decision to sell di club'' and promise say e go 'donate di proceeds to charitable foundation for di benefit of ''all victims of di war for Ukraine'' E say ''I believe say dis na in di interest of di club, im fans, di employees, as well as di club's sponsors and partners.'' Abramovich wey don deny say e get financial link to Russian President Vladimir Putin or di Kremlin but don come under increasing scrutiny in recent days, tok say di sale go dey fast-tracked. Report bin earlier comot say one Swiss billionaire Hansjorg Wyss tell tori pipo, Blick say Roman Abramovich don offer am di chance to buy Chelsea football club. E say di Russian billionaire ""wan offload Chelsea sharp-sharp"" afta dem threaten am with sanctions for Parliament. Wyss bin also tok say, ""I and three oda pipo bin get di offer to buy Chelsea. Abramovich dey try sell all im villas for England and also wan comot Chelsea from in hand sharp-sharp."" Abramovich bin hand ova ""stewardship and care"" of di club give dia foundation trustees afta Russian invasion of Ukraine last month. Abramovich buy di club for 2003 for £140m, e don borrow di club pass £1.5bn wey don held di club wella. Chelsea don win all di trophies wey dem fit win under di Russian reign. Dem include: 24 February: Russia President Vladmir Putin bin launch military invasion enta Ukraine. 25 February: Labour Chris Bryant tell MPs say make di UK goment comot Chelsea from Roman Abramovich and seize im asset say im get hand for wuru-wuru. 26 February: Abramovich announce say e dey handover ""stewardship and care"" for Chelsea give dia charitable foundation. 27 February: Foundation members dey question weda dem fit run di cluub under Charity Commission rules. Che;sea beat Liverpool 11-10 on Penalities for League Club Finals. 28 February: Abramovich collect request from Ukraine to support dem to fit reach ""peaceful resolution"" with Russia. 1 March: Di Charity Commission say e dey ""find information"" from Chelsea afta dem give di club control for im charity foundation. 2 March: Swiss billionaire Hansjorg Wyss claim say dem give am offer make e buy Chelsea. 2 March: Abramovich announce say e dey sell club" https://www.bbc.com/pidgin/sport-60592710 +entertainment Big Brother Naija Season 5 housemates biography: Lucy and Prince na new Head of House afta Nengi reign for BBCNaija lockdown "BBCNaija Housemates latest tori na say Lucy na new Head of House afta Nengi reign for lockdown season 5. Lucy select Prince as di Deputy Head of House. Lucy dey take over from Nengi di first head of of house for di 2020 lockdown season. Lucy Essien na 30-year-old entrepreneur from Cross River. She say she be simple girl not so average and can dey mean and rude if pesin step on her toes. Lucy say she believe in fairy tales, like good food and like her space. Nelson Enwerem Prince wey be 24 years old na entrepreneur from Abia. E don do modelling, fashion designing plus interior decoration and na graduate of pure physics from the University of Calabar. Prince say im like to dey ignore pipo knowingly and like working out, swimming, food and reading about ancient religions and African history. Organisers of Big Brother Naija 2020 bin don earlier announce inside one statement say dis year edition go witness upgrade in terms of benefits wey di Head of House (HOH) go fit enjoy compared to winners from previous ones. ""Dis year, di HoH privileges go see some major upgrades. For dis new season, di Head of House go get to enjoy a lounge all to themselves! Di HoH lounge go get living room area, bedroom, fitted bathroom, and a private bathroom,"" Di organizers tok for statement. ""Additionally, di HOH go dey allowed to select a deputy to assist dem to cari out dia duties and dem fit get to add some BBNaira to dia Betway Wallet....""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-53560846 +entertainment Davido Tweet wey man wey dey live with disability respond to start event wey change im viewing centre business """I just dey for shop wen one of my brodas just enta show me Davido Tweet say im wan sponsor pipo wey get business idea oh, na im I just quickly drop my own, post am."" Na so Adebisi Michael, wey dey live with disability tell BBC Pidgin as e remember di event wey start di process wey change im fortune. Michael wey bin dey run one viewing centre for Ilesha, Osun state bin dey find money to establish di place well before dat day wey Davido Tweet wey im respond. ""Di funny tin be say Davido see am, like am, Davido never respond yet but di way Nigerians, ah Nigerians, na good pipo dey here. Di way dem respond to me, message me, different tins, I dey amazed"" Michael tok. Michael tori say afta dat Tweet, pipo begin promise to send am tins and dem fulfil dia promises. ""Pipo say dem go give me dis, dem do am, I come be like, are we in Nigeria? bicos I bin no expect am. Part of di tins dem give me na im I take roof dis place."" Michael tok. Di graduate of Industrial Chemistry from Obafemi Awolowo University say im bin start di viewing centre work bicos e no wan beg. Di young man tok say im still dey single sake of say e dey difficult for am to see pesin wey go like am di wey im be. According to Michael, na 10 out of 100 ladies go agree to marry pipo like am. ""To see girls wey go like pipo like us di way we are dey difficult. Na di money some of dem won marry. Na di situation wey pipo like us dey face be dat. But I still get belief say one day I go marry,"" Michael tok. Michael also yarn say before im start di viewing centre business, im dey produce liquid soap and air freshener to sell but di business no easy sake of im condition. As you see me now, movement na issue. E get some places wia I suppose carry those tins go but I no fit just go,"" Michael tok. Michael say im biggest desire na to get work wey go dey bring monthly salary for am and make di viewing centre be im oda source of income. Di young man also tok about im family support as e thank God for dem. ""Thank God for di family wey I get. My father, my mother and my siblings. Dem dey so supportive to me. Unfortunately for me, my papa die last year November. ""Di man dey supportive to me, na my backbone and role model. If not for am, I fit no dey dis place. Anytime wey I remember am, I dey always cry sake of say im really suffer,"" Michael tell BBC Pidgin. Michael also tok about di discrimination wey pipo wey dey live wit disability dey face sometimes and assumption pipo dey make sometimes bicos of dia condition. ""Sometimes pipo dey pursue me wit 20 naira, 50 naira wen I dey go work wit my wheelchair like say I dey beg. I no blame dem sake of say pipo wey dey beg for street also dey ontop wheelchair and di mentality be say anybodi wey dey ontop wheelchair dey beg for money and no be so,"" Michael tok. Di young man encourage pipo to dey look physically-challenged pipo as normal human beings instead of to dey look dem wit pity eyes. Michael say dat kind tin dey hurt dem sake of say dem be normal human beings too but na situation cause wetin happun dem." https://www.bbc.com/pidgin/media-61138187 +entertainment Brits Awards 2021 winners: Taylor Swift win global icon - See full list of winners Na females pack most of di awards and jolly for di Brits Awards on Tuesday evening. Dua Lipa, Little Mix and win di biggest for di night even as Olivia Rodrigo win di night wither Drivers' Lincence performance. Di Tuesday show na part of pilot events to go back to normal scale large events for Britain. So dem bin no get any form of social distancing or face masks dem.. https://www.bbc.com/pidgin/world-57086400 +entertainment Elon Musk and Grimes dey 'semi separated' - See wetin dia new relationship status dey about "Elon Musk say im don ""semi-separate"" from im partner, di Canadian pop artist Grimes. Di SpaceX and Tesla CEO confam im relationship status wit Grimes to tori pipo for Page Six. E say im and di Canadian singer dey ""semi-separated"" but remain on good terms and continue to co-parent dia 1-year-old son. Di couple begin date for 2018 and welcome dia first child, named X Æ A-Xii, for May last year. ""We still love each other, see each other frequently and we dey on great terms,"" Musk tok. Grimes neva comment on di status of her relationship wit Oga Musk. Oga Musk say dem two intend to continue to dey co-parent dia child. ""E dey mostly say my work for SpaceX and Tesla make me dey primarily dey for Texas or travelling overseas Her work na primarily for LA,"" Oga Musk tell Page Six. ""She dey stay wit me now and Baby X dey di adjacent room."" Di last time we see di pair together na earlier dis month wen dem dey leave di Met Gala . Grimes bin waka di red carpet alone but her billionaire partner later join am inside di event. Oga Musk bin previously marry one Canadian author Justine Wilson, and dem two get five sons: twins Griffin and Xavier, 17, and triplets Damian, Saxon and Kai, 15. Im also marry Westworld actress Talulah Riley two times. Dem first wed for 2010 but later divorce in 2012. Dem later reconcile one year later and remarry for 2013, before divorcing again for 2016." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58689342 +politics Peter Obi running mate Datti Baba-Ahmed profile Peter Obi of Nigeria Labour Party on Friday unveil Senator Yusuf Datti Baba-Ahmed as im running mate for 2023 elections. Obi, a former govnor, na di presidential candidate of di party for di upcoming polls. Senator Baba-Ahmed, wey dey in his 50s na di owner of Baze University, Abuja and Baba-Ahmed University, Kano. Labour party reveal Peter Obi running mate for one ceremony wey hold for di party headquarters inside Abuja. Ask most pipo from northern Nigeria about di Baba Ahmed family and dem fit tell you say dem sabi at least one pesin from im family. Senator Yusuf Datti Baba-Ahmed come from a very popular family wey comot from Zaria, Kaduna State inside northwest Nigeria. It is either di pesin tell you about veteran journalists for di family Khalifa Baba Ahmed and Mahmoon Baba Ahmed or tell you about Hakeem and Nafiu Baba Ahmed wey reach peak for civil service and dey continue to play active role for issues wey concern Nigeria. So on Friday, Peter Obi, di most talked about candidate for Nigeria 2023 elections, and im Labour party unveil Datti Baba Ahmed to serve as im Vice President for next year elections. Even before im unveiling on 8 July, happun e bin attract plenty discussion across social media. Wetin many pipo sabi about Datti be say na im get one of di most popular private universities for Nigeria, Baze but apart from dat e don dey public life at one point or di oda for over two decades now. According to di man himself, Peter Obi, one of di reasons e pick Datti na because na young pesin wey get a lot to offer as e no like di idea of recycling old pipo. Datti dey in his 50s and apart from Baze University e get Baba Ahmed university for Kano wey dey northwest Nigeria. Datti na one of 33 children wey im father born and every year all di 33 dey converge for Zaria to celebrate salah with all dia children inside di family house. Dem born am for 1969 and e attend University of Maiduguri wia e study Economics for both degree and Masters. After im service year for Abeokuta, e start im career for Nigeria Security Printing and Minting before e join First Bank. Na for 2003 e really come to limelight as e contest and win House of Reps seat for Zaria and na during dat time e finish im Phd for Westminster for United Kingdom. E leave house of reps for 2007 and for 2011 e found Baze University. E contest for senatorial seat for 2011 for Kaduna north and spend one year for senate before election tribunal overturn im victory. Just recently e contest for governoship ticket for PDP for Kaduna state but lost out to eventual winner Isah Ashiru. Peter Obi na politician and businessman. Im na former govnor of Anambra state for southeast Nigeria. E serve two term between 2008 to 2016. Oga Obi bin dey All Progressive Grand Alliance (Apga) before e join PDP for 2017. Im also be sabi pesin for wetin concern economy matter. For 2019, e come out as vice presidential candidate of Atiku Abubakar. But dis year 2022 e don decide to go for di president position. Peter Obi say im administration as president go create jobs, boost Nigeria economy, and improve education. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cld2rv6kdn7o +entertainment Ghanaian actress Akuapem Poloo: Cardi B under fire for Rosemond Brown jail sentence over nude photo "Ghanaian actress Akuapem Poloo jail sentence for posting nude photo wit her son dey make pipo drag American rapper Cardi B. Accra Circuit Court sentence di actress wey real name be Rosemond Brown to three months in prison sake of say she post naked picture of herself alongside her 7 year old son for social media. But Cardi B. say di prison sentence dey too harsh as punishment for Akuapem Poloo. Di singer tok for one tweet as she dey respond to one comment wey ask her opinion on di mata on Saturday. ""I don see a lot of Americans do photoshoots like dat. Even though dis no be my style. ""I no think she bin dey go for sexual more than natural idea. I think jail dey a bit harsh."" Cardi B tok. Di American rapper, wey bin visit Ghana for December 2019, suggest social media probation or community service as alternative punishment. But dis comment no go down well for some pipo body. Demma feel say she dey support wetin no follow for Ghana. Around July 2020, di Ghanaian actress enter wrong side of de law after she post partially nude photo of herself and son online as part of en seventh birthday. Ghana Police invite am for questioning over de incident which spark public outrage sake of how she expose de son online. She plead guilty to three charges wey di court level against am which dey include: De publication of obscene materials, engaging in domestic violence in ways which dey undermine de privacy and integrity of another person. And finally engaging in domestic violence which go fit spoil di dignity of another human being. Accra Circuit Court declare am guilty after she herself plead guilty to de charge dem bring against am. Dem later sentence her to three months in prison say di reason for di punitive sentence be sake of dem wan use dis case serve as deterrent to di general public. However, Lawyers of Akuapem Poloo don indicate say dem go serve notice of appeal against de jail term wey de judge give Akuapem Poloo. Her lawyer, Andrew Vortia tell journalists say now, Akuapem Poloo ""child now dey exposed rather than for de courts to protect am."" Im argue say de actress no be ""habitual offender as she don show remorse, she also pull down de post and she no be indecent lady."" Some social media users also follow Cardi B reason say di punishment wey court serve Akuapem dey too strong." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56791265 +entertainment Who win big for 2022 Headies Big Wiz bin get a very big night for Sunday Headies Awards for Atlanta Georgia. Im gbab a total of five awards on di night for Album of di year, Song of di year, Best Collaboration, Best Afrobeats Album and Best R&B single . Anoda big winner of di night na Bnxn aka Buju wey collect dis year's Next Rated Award. Oda winners for di Night na Fire Boy, Burna Boy, Tems with three awards each. Dis go be di first time wey di Nigerian music award brand go move im venue go America. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cv2eevqn8rmo +politics Nnamdi Kanu case for Appeal Court as e happun "By Tamara Ebiwei Di Appeal Court for Abuja don hear di case of di proscribed Indigenous People of Biafra, Ipob leader Nnamdi Kanu. Justice Jummai Hannetu Saki wey preside ova di case say make dem go study di mata den dem go fix date for ruling. Lead Counsel for di Appellant, Mike Ozekhome bin beg court to strike out di remaining seven-count charges wey Federal High Court retain afta dem strike out eight from di 15. Di respondent wey be di lawyer wey represent federal goment David Kasuwe for im argument tell court strike out di appeal wey Nnamdi Kanu bring come, sake of say e lack merit. Earlier, Justice Jummai Hannatu Saki strike out di motion of accelerated hearing, sake of say e don dey overtaken by events. She also keep di bail application for Nnamdi Kanu for corner, pending di Appeal court ruling. For May 2022, Justice Binta Nyako of di Federal High Court remove some of di charges from 15 to seven. Di Federal High Court wey siddon for Abuja bin dismiss di bail application of Nnamdi Kanu. Trial Judge, Justice Binta describe di application as “gross abuse of court process.” Justice Nyako for her ruling for June 2022 say di suit na attempt to kontinu to litigate on issues wey dem bin don rule on top. She advise di applicant to approach di Court of Appeal on di issue of bail. Justice Nyako adjourn di mata to 14 November for mention and to also know di outcome of di case for Appeal court. Meanwhile, Nnamdi Kanu say e dey fight to defend im pipo no be to kill dem. Di leader of di Indigenous People of Biafra add say di Biafra struggle na to fight for di pipo and not to kill-kill di pipo of di region. Kanu tok wen im bin dey  response to di outcome of im bail application for di Federal High Court, Abuja for one interview afta im trial. ""I no dey disappointed, why I go dey, na wetin we expect to happun, but I want our pipo to dey very calm, I want Biafra land to dey peaceful, calm and very very peaceful. We dey fight to defend our pipo, not to kill dem. We dey fight to defend dem, dats why I dey here, and we go continue to do so until we get victory."" E tok. Na for June 27, 2021 security agencies arrest Kanu, di Ipob leader for Kenya. Since den im trial wey attract di interest of plenti Nigerians and odas around di world don begin for am to face di charges federal goment sama against am." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw9drje0j3vo +sports Fifa ban on Ahmad go make oda African kontris sharp teeth for Caf 2021 presidency "Confederation of African Football (Caf) president Ahmad don chop five years ban from Fifa for breaching dia code of ethics. Di Fifa vice-president, age 60, break rules relating to duty of loyalty, offering and accepting gifts abuse of position as well as misappropriation of funds. Oga Ahmad, wey BBC Sport Africa tok about im possible ban last month, also chop fine of $200,000. Ahmad Ahmad don deny all di accuse dem. Last month, di Fifa vice-president from Madagascar announce him intention to go for a second term for office wen Caf elections take place next March. Dis now na big comma for am now as im gatz pass eligibility test to resume im place for Fifa Council. ""Di investigation into Oga Ahmad behaviour... from 2017 to 2019 relate to many Caf governance mata, including di organisation and financing of one Umrah pilgrimage to Mecca, im role inside Caf business wit sports equipment company Tactical Steel and oda activities,"" according to di Fifa statement. Fifa also fine Ahmad $200,000. Oga wey many bin expect say go run second term as Caf president, bin deny di accuse and even now e get right to appeal di ban, if im want. Otherwise, di March 2021 Caf presidency go rest on di shoulders of oda candidates. In situations like dia, wia Fifa don ban lead of continental or a kontri footbal oga, di global joinbodi demsef go take over on a temporary basis. At least until new leader come out either through voting or appointment. For African football, Senegalese executive Fatma Samoura, wey also be Fifa Secretary-General na im don dey run affairs for di continent. And e be like dis temporary arrangement go continue until March elections. Amaju Pinnick - Nigeria As at September 2021, di head of Nigeria Football Federation (NFF) bin tok am openly say im dey eye to run for Caf presidency although e admit say before before im follow for pipo wey desire for Ahmad to do pass one term. ""From di beginning di idea na to have incumbent Ahmad get re-election for a second tenure or even third tenure,"" Pinnick tell BBC Sport Africa. But e be like say as water come dey pass garri for Ahmad investigation, e decide to withdraw and support anoda candidate from oda side of di continent. For October, Pinnick tok of im support for Patrice Motsepe of South Africa: ""If pesin dey wey sabi pass you, you need to learn from am and queue behind him and wait for your time."" Patrice Motsepe - South Africa Africa 10th richest pesin wit money wey reach $2.4bn (according to Forbes), Motsepe no be stranger to football as im na di owner of top division Mamelodi Sundowns club for South Africa. E announce say im go run early dis month and since then Nigeria, Sierra Leone and Botswana don show support for im candidacy. Fun fact for una: Oga Motsepe big sister na di wife of South Africa president Cryril Ramaphosa. Jacques Anouma - Côte d'Ivoire Anouma wey bi former member of Fifa Executive Committee (now Fifa Council) between 2007 and 2015, announce im own desire some days before Motsepe own. And now e don officially enter race after di Ivorian federation give am dia support. Although dis na di second time im dey try run - after im first attempt 7 years ago." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55040438 +sports Man Utd: Fans call for Ole Gunnar Solskjaer sack afta dem lose Europa League final to Villarreal "Manchester United fans dey para for social media afta dia team lose di Europa league final to Villarreal on Wednesday night. United lose to di Yellow Submarines afta David de Gea miss di decisive penalty of di game. Fans dey use #OleOut to tok dia mind about di match and di future of di manager Ole Gunnar Solskjaer. Thousands of pipo feel like say dem need to chook mouth for di mata. Di #OleOut get ova 47, 000 tweets See some of dia tweets here. But Manager Ole Gunnar Solskjaer don accept say di club no dey successful dis season. Solskjaer bin speak to BT Sport afta di game im say: ""We need to get better, simple as dat. ""We do well dis season to come through. Di start of di season bin dey difficult. We bin no do pre-season and we lose three of di first six games. ""We push for di league, maybe close to di top than wetin we think and we reach di final. But you need to win di finals to make am a good season."" Former United midfielder Paul Scholes, wey bin speak to BT Sports punditry team, bin question whether di defeat really pain di United players. But Solskjaer stand up for his team and believes say dem get di right character to respond positively to Wednesday defeat in Gdansk. ""We get a strong, competitive squad. Di spirit for di squad dey good. Di players dey really feel bad,"" na wetin Solskjaer tok. Di Red Devils finish second for Premier League but dem neva win any trophy since 2017." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57265412 +entertainment Coronavirus: Davido say im fiancée test positive for Covid-19 Nigeria music star David Adeleke, AKA Davido say im fiancée Chioma Rowland, don test positive to coronavirus. Di musician announce am on Friday night, March 27, 2020, ontop im official Instagram page. Im say although Chioma no dey show any symptoms, dem decide to test sake of dia recent travel history. Di musician say di result of im baby, plus 31 oda of dia close associates come back negative. Davido say Chioma no dey show any symptoms for now, but she dey for quarantine while im don go into full isolation for a minimum of 14 days. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52068398 +sports Samuel Okwaraji: Five African footballers wey die for pitch August 12, 2019, make am 30 years since former Super Eagles player Samuel Sochukwuma Okwaraji die for field. Okwaraji collapse 10 minutes to di end of Nigeria World Cup qualifying match against Angola for 1990 for National Stadium Lagos. According to Wikipedia, im die from complication of hypertrophic cardiomyopathy, im autopsy show enlarged heart and high blood pressure. Before im die, Okwaraji play for some European clubs like AS Roma, NK Dinamo Zagreb, VfB Stuttgart and SSV Ulm. If to say im still dey alive im for be 55 years dis year. To keep im legacy alive im get statue in front of National Stadium Lagos. Official register no dey of pipo wey don die as dem dey play football. So Instead we go use list from Wikipedia. Ivory Coast footballer Cheick Tiote die at di age of 30 afta im collapse during training for China for June 5, 2017. Tori be say Tiote suffer from Cardiac arrest. Cameroon midfielder Patrick Ekeng bin dey play for im club Dinamo Bucharest for Romania wen im die at di age 26. Ekeng fall for pitch for di 70th minute for match wey dem show live for Romania television between Dinamo and Viitorul. E die two hours later for hospital. Gabon international Moise Brou Apanga die from suspected heart attack at di age of 35 for April 26, 2017. Di 35-year-old collapse during training session with im Gabon club FC 105 Libreville. Apanga play for di Panthers for di Africa Cup of Nations for 2010 and 2012. Zambia International Chaswe Nsofwa bin dey train with im club for Israel wen tragedy happun. Tori be say im collapse for training and later die for Isreali hospital. Marc-Vivien Foé bin dey Cameroon 2003 FIFA Confederation Cup squad, di tournament wey continental champions from six continents dey play. For dia semi final match against Colombia for June 26, 2003, Foe collapse for field. No player bin dey near am. Afta dem try to revive am for pitch dem stretch am comot. Medics spent 45 minutes to try to restart im heart although im bin dey alive wen im arrive di stadium medical centre, e no tey im die. Dem do Autopsy to find out wetin kill am, di autopsy show say im get hypertrophic cardiomyopathy, wey be heart condition wey fit increase di risk of sudden death during physical exercise. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49320100 +sports Newcastle vs Liverpool highlights: Martin Dúbravka no stop Naby Keita goal for Reds Newcastle and Liverpool Premier League match on Saturday see di Reds move top of di table. Liverpool leg still strong for dia fight to win di quadruple afta dem win Newcastle 1-0. Di win mean say dem don move back to di top of di Premier League - even though e fit be for few hours at least. Jurgen Klopp bin make five changes for St James Park, including dropping dia top scorer Mohamed Salah for bench. Klopp introduce di changes afta dia Champions League semi-final on Wednesday. Na move wey bin look like say e go backfire as Newcastle wey dey fine form bin start di game strongly, Dem press Liverpool high and force dem to make some mistakes. But Liverpool grow into di game and dem begin dominate possession wen Naby Keita score for di 19th minute. Di midfielder show great experience as in im dribble across di box and past Martin Dubravka before pass di ball inside di net. Sadio Mane for make am 2-0 before half time wen im shot on counter bin dey too close to Dubravka, wey also make one fine save from Diogo Jota header. Di Newcastle fans, bin vex say referee allow play to continue in di lead-up to Liverpool goal because Fabian Schar bin dey down injured. Dem bin think say Miguel Almiron bin don equalise afta e dribble Alisson, but dem disallow am for offside. Di home team start well again for di second half, but na Liverpool wey bin dey close to scoring anoda goal. Mane effort go wide from close range before Martin Dúbravka push Jota shot ova. Liverpool no really play well, but di koko be say dem do di job. And di Reds dey two points clear at di top of di League table. Now di pressure dey back on Manchester City, wey go face Leeds for Elland Road later Saturday. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61249664 +entertainment "Max FM Iyah Jogbo: Lagos ""Wetin Dey"" presenter Emmanuella Pobeni Adepoju don die, dis na her biography and how she die" "Max FM Iyah Jogbo, di Lagos On Air Personality wey popular wella for her ""Wetin Dey"" radio show don off mic forever. Iyah Jogbo na one ogbonge radio broadcaster wey real name na Emmanuella Pobeni Adepoju die on Thursday 24 July, 2020, according to her employer, di management of TVC Communications di owner of TVC, TVC News and Max Radio. Di show ""Wetin Dey"" wey she always dey anchor every afternoon for Max FM carri her enta spot light inside Lagos State South West Nigeria. Her funny characters during di programme and di way she dey engage audience make her get plenty fans. Di oga patapata of TVC Communications, Andrew Hanlon say di news of Emmanuella death dey shocking and everybody for di media organization feel bad for di news. Premium Times report say Iya Jogbo begin broadcasting work for 1995 wen she do IT for Radio Lagos, she start as News caster and presenter as she dey present Radio Lagos Global Focus. She be correct voice over artist as na her voice di popular ""Shoppers Guide"" for English and ""Karakata"" for Yoruba and she carry out many voice over projects. Iya Jogbo also na ambassador for @_amotherslove.ng, na programme wey dey always educate parents on how to take train, discipline and educate dia children. Her programme for radio dey bring to focus societal ills, bad goment, and how Nigeria fit beta, she also don interview plenty ogbonge artists for her show. According to report she get four children. Many of her fans enta social media to bid her farewell." https://www.bbc.com/pidgin/53536024 +business Why Japan dey ask 37 million pipo to off lights "Japan goment don ask pipo for Tokyo and di surrounding area to use less electricity on Monday, as e warn say supplies go dey strained as di country dey face heatwave. Di Ministry of Economy, Trade and Industry expect say demand for power to go dey ""severe"" dis afternoon local time. E say make pipo switch off unnecessary lights but still use air condition to avoid heatstroke. For weeks, officials don dey warn of a power crunch as temperatures dey rise. Over di weekend, di temperature for central Tokyo rise above 35C, while di city of Isesaki, wey dey northwest of di capital, record 40.2C. Dat na di highest temperature dem don eva record in June for Japan. June mark di start of summer in Japan, wen temperatures typically dey stay below 30C during di month. For statement on Sunday, di ministry say excess generating capacity for electricity dey expected to drop to 3.7% on Monday afternoon in Tokyo and eight surrounding prefectures/districts. Dem say a buffer of 3% dey necessary for stable power supply. Di goment ask pipo to turn off all unnecessary lights for three hours from 15:00 Tokyo time (07:00 BST) while dem go ""properly use air condition and drink plenti water (hydrating) during hot hours"". Although electricity providers dey work to increase supply, di ministry say di situation dey ""unpredictable"" as temperatures dey climb. ""If demand increase with sudden supply troubles, di reserve margin go fall below di minimum wey dey required of 3%,"" e tok. Japan power supply don dey tight since one earthquake happen for di northeastern region for March and e force some nuclear power plants to suspend operations. Officials also don close several old fossil fuel plants as dem dey attempt to cut carbon dioxide emissions. All dis issues, along with a rise in demand for electricity, don result to a power squeeze. Earlier for dis month, di Japanese goment tell households and companies to save as much electricity as possible during di summer. Meanwhile, Japanese public broadcaster NHK don report say dem don carry 46 pipo for Tokyo go hospital for suspected heatstroke, as of Sunday afternoon. Dem also report say one 94-year-old man for nearby Kawagoe city dey suspected to don die from di heatstroke condition. Di news dey come after Australian officials ask households for New South Wales - a state wey include di biggest city for di country Sydney - to switch off dia lights in di face of energy crisis. Na only last week den lift restrictions on di Australian wholesale energy market." https://www.bbc.com/pidgin/articles/czvdw7q7r2eo +politics Rivers Governorship Election Tribunal: Wike give Awara technical knockout for Supreme Court "Nigeria highest court don confam say true true na Nyesom Wike win di March 2019 governorship election for Rivers State. Supreme Court uphold di appeal wey Govnor Wike, file to challenge di decision of Court of Appeal wey bin put back di petition wey im main challenger, Biokpomabo Awara, di candidate of African Action Congress, AAC bin file. Di panel of three Justices wey Justice Inyang Okoro lead say Biokpomabo Awara petition na exercise wey go die in di end. Di highest court come rule say hearing of petition wey dem don abandon no amount to any purpose, but just dey for book. Afta di judgment, lawyer to Wike, Ferdinand Orbih SAN, say di two judgments na landmark pronouncements wey Supreme Court give. ""Across all di tribunals for di konri, di issue dey always be wetin be di relationship between di power of tribunal to dismiss petition wey dey abandoned and di constitutional provision wey say interlocutory matters wey concern jurisdiction must wait until di final judgment."" Orbih add say by di two judgments, di mata wey AAC for Rivers State file don collect di final nail for im coffin, and e dey dead buried forever. Lawyer to AAC, Henry Bello, say di two judgments wey di Supreme Court deliver cover six appeals. Bello say ""di first judgment address abuse of process. For di tribunal for Port Harcourt, appeal bin dey against a decision of di tribunal and at di same time, di same tin for dat appeal bin dey seek clarification for anoda application and our argument for di tribunal be say na abuse of court process so make dem dismiss am."" ""Di tribunal agree wit us come dismiss am but dem go Court of Appeal wey come disagree wit di tribunal say no be abuse of court process. Today di Supreme Court don uphold our position say na abuse of court process."" Bello add. Bello say di Supreme Court on 15 October for anoda appeal uphold im appointment as di lawyer to AAC. So based on dat judgement, lawyer to Awara, Festus no fit file processes for am again, but di lawyer no gree hear come continue to dey file processes even afta im don take over to dey conduct proceedings according to Order 9 rule 35 of di Federal High Court rules wey dey applicable by paragraph 52 of di first schedule to di Electoral Act. ""And so we contend say e dey wrong. So di Supreme Court by dis judgement now don set aside all those processes wey dem file on my behalf come say all those processes dem file na abuse of court process."" ""Di Supreme Court today don agree say all those processes dey null and void so no application bin dey for issuance of pre-hearing notice."" ""Di Supreme Court today too don hold say you must dey diligent for di prosecution of your election petition, if you no dey diligent, di tribunal get right to dismiss am. ""Dis judgment don set serious precedence wey go assist us for all election petitions for dis country moving forward,"" Na so Henry Bello tok. Today di Supreme Court don tok say wen you don abandon any issue, you no need to wait until di final judgment before di tribunal fit pronounce am say you dey dismiss di petition because e dey abandoned"" Orbih tok. Awara bin go Appeal court to ask make di Rivers Governorship Tribunal hear im petition against di election of Governor Wike, after di Tribunal dismiss im petition. Di Tribunal for July, 2019 bin don dismiss di AAC petition becos dem say di petition bin dey technically abandoned sake of say AAC and im Candidate fail to meet some key procedural requirements as to apply for pre-hearing information, based on paragraph four of di first schedule of di electoral act. Dis appeal come make di Governorship Tribunal hear di AAC Candidate Awara appeal but for 5 October, 2019, di tribunal uphold di election of Governor Wike come tell Awara to pay cost of three hundred thousand naira (N300,000) each to Govnor Wike, di kontri main opposition party - People Democratic Party (PDP) and Nigeria election office - Independent National Electoral Commission (INEC)." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50184685 +entertainment Ada Jesus: See Rita Edochie first social media post afta Mercy Mmesoma death "Barely 24 hours afta Nigerian comedian Ada Jesus die of Kidney failure, Nollywood actress Rita Edochie don post for social media for di first time. Madam Rita and popular pastor Prophet Odumeje bin claim say di comedian make false accusations against dem. For dis her latest post she no tok anything about di comedian. She just caption am ""JEEEEESUS is LORD forever. Lord almighty make me a strong woman and dat I will remain."" na wetin she add put. She end di post wit ""nobody fit kill di seed."" Many pipo don begin troll di actress for social media for her post and wetin she bin tok before about Ada Jesus wen she dey alive. Di post don get ova 22,000 views with 883 comments. See some of di comments below: Madam Rita claim say Ada Jesus lie about her and her pastor, Prophet Odumeje, Di gist be say Ada Jesus claim say Prophet Odumeje dey perform fake miracle. Di comedian later apologise to Prophet Odumeje and Rita for inside di prophet church But di Prophet Odumeje and Madam Rita bin no forgive her then. Later di two of dem announce say dem don forgive her afta many pipo bin hala ontop di mata for social media. Rita release video wia she say ""I dey here to tell all of una say I don forgive Ada Jesus, from my heart of hearts Ada Jesus I don forgive you"". Prophet Odumeje later announce say him too don forgive her e later give Ada Jesus family one million naira for her treatment but di family later reject. Ada Jesus die on Wednesday April 21, 2020 afta she battle wit Kidney disease at di age of 23." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56849141 +health Coronavirus stats: Donald Trump admit say US go 'get worse before e go beta' "US President Donald Trump don sama warning say di coronavirus pandemic mata for US ""go become worse before tin go begin beta"". Oga Trump wey tok dis one as e resume im coronavirus briefing order everybody for America to wear face mask. E tok say Face mask get work wey e dey do and e show say dem dey together. Di president no wear face mask for di briefing as im no reason say e dey necessary. Im aides don tell am say make e use anoda eye look di virus as cases of pipo wey dey infected dey rise for di US. Di daily White House news conferences stop for April afta Oga Trump tok say if dem inject pipo wit disinfectant e go fit treat di virus. Oga Trump tok say ""If you no fit do social distancing, wear face mask"". ""Whether you like the mask or not, e get wey e dey do and e dey epp, we need everything we fit get."" Di Presido wey dey always call Covid-19 di ""China virus"" - remove face mask from im pocket but e no wear am. The president is facing an uphill climb to re-election in November against Democratic challenger, Joe Biden, according to opinion polls. Oga Biden on Tuesday accuse Oga Trump say im fail Americans wit di way e take handle di pandemic. ""E don leave una, E don leave dis kontri,"" di former US vice-president tok. For di briefing, di medical experts wey dey always join for di meeting no dey. He say make everybody for America continue to dye wash dia hands, do social distanceand dey serious wit dia hygiene. For young Americans, e say make dem no go bar wey pipo to gada and avoid any indoor party wey pipo to full. E say make dem dey safe and smart."" Oga Trump no like to dey wear face mask in front of tori pipo, e claim say some pipo dey wear mask as political statement against am. Recently tori pipo take one foto of wear im wear mask for di first time as e military hospital. When dem ask am for di briefing why e change im mind on top face mask, Oga Trump tok say even health experts dey change dia minds. For March, Dr Anthony Fauci, one of di doctors we dey lead di president' coronavirus task force, and US Surgeon General Jerome Adams tok say pipo for US no need wear mask, say e no dey necessary. Since at least April, di US Centers for Disease Control bin recommend say make Americans begin wear face mask for public. Dr Fauci don begin argue now say make US authorities dey force pipo to wear mask for public, although Oga Trump don reject di suggestion say make White House issue national order for di mata. For di briefing, di president continue to dey give hope say one di virus go ""disappear"". He also claim say di pipo wey don die for di virus no plenty for America like other places for di world and dis no be true. According to Johns Hopkins University, US mortality rate dey number 10 out of di 20 worst hit kontris. United States record nearly 3.9 million Covid-19 cases and over 141,000 deaths - di highest for di world." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53497438 +sports Man Utd beat Liverpool to win dia first Premier League game Manchester United and Liverpool game end for 2-1 on Monday night. Marcus Rashford 53' minute goal and Jadon Sancho 16'minute goal na im secure di win for Man Utd. Mohamed Salah score Liverpool only goal for di 81' minute of di match. Manchester United manager Erik ten Hag bin make changes to im starting line-up for dis game. E drop captain Harry Maguire and Cristiano Ronaldo for bench. Dis game na di Red devils second match for Old Trafford afta dia 2-1 defeat to Brighton for di first week. Di two teams bin neva win any match dis season for premier league, United don lose two games while Liverpool don draw two. Before tonight game Manchester United bin dey number 19 position while Liverpool dey number 15 position While Liverpool play 4-3-3 formation, Manchester United play 4-2-3-1 to win di game. Man United next match na away to Southampton on Saturday while Liverpool go jam Bournemouth. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cprlgwlxdgeo +health Queen Elizabeth test positive for Covid-19 "Di Queen don test positive for Covid, Buckingham Palace don tok. Di Queen dey experience ""small cold-like symptoms"" but expect to continue ""smal-small duties"" for Windsor over di coming week, di palace tok. ""She go continue to receive medical attention and go follow all di appropriate guidelines,"" dem add for di statement. Di Queen, 95, bin dey in contact with her eldest son and heir, di Prince of Wales, wey test positive last week. Tori be say some pipo don test positive for Windsor Castle, wia di Queen dey live. Prime Minister Boris Johnson say e dey sure say ""I speak for everyone for wishing Her Majesty The Queen fast recovery from Covid and a fast return to good health"". Leader of di Opposition, Labour Sir Keir Starmer, also wish di monarch ""good health and fast recovery"", e add say: ""Get well soon, Ma'am."" Di announcement dey come weeks afta di UK longest reigning monarch reach her Platinum Jubilee of 70 years on 6 February. On di day before her Jubilee, she carry out her first major public engagement for more dan three months, she meet charity workers for Sandringham House. Di Queen, wey go be 96 for April, get her first vaccine for January 2021 and e dey believed say she don get all her follow-up jabs afta dat. BBC royal correspondent Nicholas Witchell said she bin dey take life ""more easily"" since she spend a night in hospital for medical checks for October last year. For November, di Queen miss di Remembrance Sunday service with her back wey get problem, weeks afta doctors advise am to rest afta she go hospital. Na di first time she miss di ceremony for di Cenotaph for London as Queen, oda dan wen she dey pregnant or dey abroad. While on light duties e dey likely say di Queen go dey read documents from UK goment ministers and Commonwealth representatives wey dem go send give am every day, she go dey approve and sign dem wia necessary." https://www.bbc.com/pidgin/world-60382563 +politics 2021 prophecy by Ghana pastors: Yemi Osinbajo go become Prez, conflicting prophecies about John Mahama election petition. As de year 2020 end on December 31, some church leaders for Ghana drop prophecies about things wey go happen in 2021. One of de main things which dey happen be prophecies wey Ghanaian prophets dey drop about things wey go happen for Ghana and other parts of de world in de course of de new year. From conflicting prophecies about Ghana presidential election petition hearing in favour of NPP den NDC, to claims say Nigeria Vice Prez go become president in 2021. Dis be some of de prophecies wey de mist notable prophets for Ghana drop about 2021. Prophet Owusu Bempah Prophet Nigel Gaisie https://www.bbc.com/pidgin/tori-55484893 +entertainment Kasala for India rapper death "Di murder of rapper Moose Wala for di northern Indian state of Punjab don create kasala. E happun one day afta dem reduce di number of im security cover. Unknown gunmen shoot Shubhdeep Singh Sidhu wey dem dey also call Sidhu Moose Wala. Di 28 year-old murder occur on Sunday evening when im be dey travel for di state Mansa district. Two odas bin injure from di attack. State police chief say one Canada based gangster don claim responsibility of di attack. VK Bhawra further explain on Monday say, ""one Goldy Brar don claim responsibility on behalf of di Lawrence Bishnoi gang"". Dis na afta Moose Wala family accuse di police say dem no do beta investigation before dem blame di mata on gang rivalry. Opposition leaders don dey ask why dem reduce di rapper security. Police say dem reduce Moose Wala security detail from four commandos to two. Dis officers dem bin no even dey with di rapper wen im die. E dey among di ova 400 pipo for Punjab wey goment don reduce dia security details or comot dem pata-pata. Punjab chief minister Bhagwant Mann say part of di reason na to crack down on so-called ""VIP culture"". Di culture dey put politicians ova normal citizens. Police officials say dem do am to put more officers for security. Dis na ahead of di anniversary of di wahala Operation Blue star. Na wen Indian army attack di Sikhs' most sacred shrine for 1984. But di move create kasala wen di list of di pipo dem dey reduce security for leak for social media. Some pipo say e fit increase threat on dia lives. Dem born am to ansa Subhdeep Singh Sidhu for Moosa village for Mansa district bin study engineering for Punjab before im come waka go Canada for 2016. Di very next year, im drop im first track wey im call ""So High"" under di name of Moose Wala. Since dat time, e don blow for Punjab and with di Sikhs wey dey Canada and UK. In di four years of im career, di 28 year old rapper bin turn one of di most famous players for di Punjab hip-hop scene. BBC Punjabi tori pesin say from ogbonge parties for di state to tea shops dem for di rural area, na so so Moose Wala dem just dey play. Im songs wey im write and compose get ova 5 billion views and e enta Top 5 for UK charts last year. E also feature for The Guardian as one of di best new artists of 2020. But e don enta wahala with di law before. For May 2020, dem book am say im shoot AK-47 for shooting range during Covid lockdown. E bin also get police case say im dey promote violence and gun culture with im song, Sanju. But dem neva convict am for any of dis alleged crimes. For 2021, e enta politics wia e contest as candidate under India main opposition, di Congress party. E bon dey contest for di 2022 Punjab assembly elections but im no win, howeva di mata boost im popularity. Im last song, The Last Ride wey im release dis month May, bin show photo of di crime scene of Tupac murder wey some fans dey see as foretelling of how im die sake of say dem shoot Moose Wala inside im motor too." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cxey4l0pj2ro +sports Champions league - Wetin teams need for dis group stage Five teams don already book dia place for di Champions League knockout stage - so which teams go to take di final 11 spots as we enta round five of matches for di group stage? Manchester City don win dia group but Liverpool, Chelsea and Tottenham still get work to do. Meanwhile, Celtic and Rangers, meanwhile, don already comot for Champions League although dem get chance of dropping into di Europa League. Make we torchlight wetin each team need for dis season competition. Qualified: Napoli Already out: Rangers Wednesday: Ajax vs Liverpool, Napoli vs Rangers (Kick off 8pm WAT) Liverpool just need a point for Amsterdam to seal dia place for di knockout stage. Dem probably need to win to maintain dia hopes to finish top of di group. Ajax need to win by more dan one goal to keep dia hopes alive as dat go give dem a head-to-head advantage on di Reds if dem finish level on points. Rangers hopes of third spot and Europa League go end if Ajax result beta pass dia own. Qualified: Club Brugge Wednesday: Club Brugge vs Porto (17:45pm), Atletico Madrid vs Bayer Leverkusen (8pm) Porto fit book dia place for di last 16 if dem win and Atletico Madrid no win. But Atletico victory go mean say qualification now dey dia hands as dem go face Porto for di final game. Qualified: Bayern Munich Already out: Viktoria Plzen Wednesday: Inter vs Viktoria Plzen (5:45pm), Barcelona v Bayern Munich (8pm) Barcelona fit don comot for Champions League before dem even play on Wednesday. If Inter beat Viktoria Plzen den na dem go take di final knockout spot, thanks to dia head-to-head record against Barca. Wednesday: Tottenham vs Sporting Lisbon, Eintracht Frankfurt vs Marseille (both games na 8pm) Spurs go qualify for di knockout stage wit one game to spare if dem beat Sporting. If Spurs win, then Marseille fit also go through if dem beat Frankfurt, as dem get a better head-to-head advantage ova Sporting. Tuesday: Salzburg vs Chelsea (5:45pm), Dinamo Zagreb vs Milan (8pm) Chelsea know say if dem win for Austria dem go qualify for di last 16 - or if dem draw and Milan beat Dinamo Zagreb. Salzburg go qualify if dem win and Milan no win. Qualified: Real Madrid Already out: Celtic Tuesday: Celtic vs Shakhtar Donetsk, RB Leipzig vs Real Madrid (both game go kick off by 8pm) RB Leipzig go reach di last 16 if dem beat Real Madrid wey don already qualify already-and Shakhtar lose to Celtic. Scottish champions Celtic must win to keep dia Europa League hopes alive. Qualified: Manchester City Tuesday: Sevilla vs Copenhagen (5:45pm), Borussia Dortmund vs Manchester City (8pm) Dortmund go qualify if dem beat City. A draw too go dey enough if Copenhagen no beat Sevilla. Di German side fit even qualify before dem play if di oda game end for draw. Tuesday: Benfica vs Juventus, Paris St-Germain vs Maccabi Haifa (both games na 8pm) Benfica and PSG both know say a win for dia games go take dem through. If both matches end for draw di pair go also go through. Juventus go need to win both of dia games to get any hope of going through. *All times dey set to WAT https://www.bbc.com/pidgin/articles/cx8wp1e7en9o +entertainment BBNaija saturday night party: Liquorose and Saga dance battle plus oda tins wey happen for di housemates 1st party "On Saturday, July 31, housemates for di Big Brother Naija 'Shine Ya Eye' show do dia first Saturday night party. According to Big Brother di theme for di party be 'Rep your style' and di contestants no carry last for dia fashion style. Evribodi come to slay. Some interesting bin happen for di dancefloor, like wen Liquorose waka comot for di middle of di party, go cry. She come dey tell Emmanuel say: ""I no sad, I dey happy. I just no fit believe say I enta dis house."" Dance battles Di housemates bring beta energy come dance but pipo dey vex say dem no too see watch am. Part of wetin sweet pipo na wen Liquorose wey be dnacer, dey face Saga - so tay e comot cloth. Even Angel and Sammie follow give us hot hot dance steps. Who be di wild card? Di housemates still dey suspect demsef as dem dey try find who be di wild cards. Di mata enta gear two afta Biggie give di Head of House one interesting clue. As tins be so, if di housemates fit find who be di wild cards, dem go send dem home for di eviction show. Laycon 'Verified' single remix wit housemates names Wen DJ N come play last season winner Laycon song 'Verified' for di party, na e add extra ginger to di show. For dis version, Laycon remix di song wit di name of di 'Shine Ya Eye' contestants. Di 22 housemates dey compete for 72 days for prize money of N90m." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58045949 +entertainment Big Brother Naija 2021: BBNaija season 6 starting 11, Ebuka swag & oda tins wey happun for day one of di reality show "Big Brother don finally reveal di faces and names of some of di housemate for di new season of di biggest reality TV show for Nigeria, Di sixth season of Big Brother Naija officially start on Saturday July 24, 2021. Dis season show go last for 10 weeks and dem title di show 'Shine Ya Eye' BBNaija make history yesterday, check out some of di highlights for Africa biggest reality television. Dis year di show organizers change dia launch format, dis na di first time for di history of di show wey dem dey do two launch shows. For di launch show on Saturday di show host Ebuka Obi-Uchendu introduce Biggie starting 11. And all Biggie starting 11 wey enta di house on Saturday na guys. Di guys wey come from different background wey include modelling, acting, and medicine no fit hide dia joy as dem promise to bring entertainment to di show. On Sunday na im Biggie say im go reveal who di female housemate dem be. Di show host Ebuka Obi-Uchendu package himself wella for di launch and many of im fans for social media hail am for im choice of outfits. Ebuka wear two different outfit for di launch show. One of di outfit wey im wear na traditional Efik attire; black cap, black waist coat, white shirt and white wrapper. E complete di look wit walking stick. While di oda cloth na white suit wit fancy design for di collar and pocket wit black inner shirt. Di presenter totori many pipo yesterday with im Swag. During di live show on Saturday, Nigeria musician Ladipoe perform im hit single ""Feeling"" wey im feature Buju . Na him be di only artist wey perform on di night. Big Brother Naija get many fans and some of dem no waste time to chook mouth for di brand new season. Osayi Linus write for Facebook say: ""We no go hear word again dis period"", While Ngozi Kanu tok say, ""Na Pere for me ooo, di guy cute biko, team Pere make some noise"", Anoda pesin, Confidence Chinyere say ""BBNaija season six go be gbas gbos"", And Jessica John say: ""No be small shine ya eye biko"", Dis season housemates dey compete for di grand prize of N90million naira worth of prizes, wey be di biggest reward since di show start." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57960226 +business Ghana Cedi notes: Why Bank of Ghana dey phase out Ghc1 and Ghc2 notes "Bank of Ghana announce plans to phase out Ghc1 and Ghc2 notes from circulation soon. Govnor of BoG, Dr Ernest Addison explain say de plan be to replace de paper notes with coins. ""De longer term plan be say we go go replace de Ghc1 and Ghc2 notes and use Ghc1 and Ghc2 coins"" he talk journalists. Dis be sake of de need to manage de cost involved in printing new Ghc1 and Ghc2 notes. De reason for de high cost involved in printing dis notes be sake of de frequent replacement since dis denominations dey return dirty and worn out mostly. Dr Addison explain say ""de plan be say one and two cedi notes go be phased out. Dem no be cost effective."" ""Mostly dem dey return torn, soiled and dirty"" he add. In 2007, Ghana phase out old currency to introduce de current Ghana cedi denominations. De denominations Ghana dey operate be Ghc1, Ghc2, Ghc5, Ghc10, Ghc20, Ghc50, Ghc100 and Ghc200. De other coins Ghana introduce be 1 pesewa, 10 pesewas, 20 pesewas, 50 pesewas, one cedi and two cedis are coins. In 2018, BoG introduce Ghc100 and Ghc200 notes as part of efforts to allow high volume transactions to happen without de use of plenty notes." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58704526 +sports UFC 263 results: Israel Adesanya beat Vettori again to retain im UFC middleweight title "Nigeria-born UFC champion Israel Adesanya don retain im middleweight title afta e defeat Marvin Vettori for UFC 263. Adesanya defeat Vettori through unanimous decision (50-45, 50-45, 50-45) afta Round 5. Dis na di second time wey Adesanya go beat Vettori for UFC. Di two fighters bin first face each oda for April 2018 for Adesanya second fight for UFC. Di Nigerian claim victory dat night via split decision. Vettori start di bout wit aggression and land early takedown, but Adesanya soon settle into im work and dominate di striking exchanges, as im use leg kicks to punish di challenger from distance. Adesanya bin dey in full control of di match despite di plenty mouth wey Vettori make in di build up to di game. Vettori try to take Adesanya down against di cage for di end of di fourth round but di Nigerian-born fighter stand im ground as e reply Vettori attempt wit leg kicks. After dem officially announce di result, Adesanya dedicate di victory to im teammate Fau Vake, wey be up-and-coming fighter wey die in May from injuries wey im sustain for alleged attack for Auckland, New Zealand. ""I just wan tok say Fau Vake, Fau Vake, Fau Vake, I love you, man... Dis fight I dedicate am to you, Fau,"" im tok. During di postfight interview, Adesanya tok say Vettori tell am say im believe say na e win di fight for di Octagon. Adesanya reveal say e tell Vettori to ""keep thinking that, whatever helps you sleep at night."" Dis victory na Adesanya third successful middleweight title defense, im never lose any fight for di middleweight category for UFC." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57458582 +politics Court say make Obi-Datti rally no assemble for Lekki toll-gate? "Di National Lawyers Coalition for Labour Party Presidential candidate for di Nigeria 2023 elections Peter Obi, don describe as fake news di tori wey dey circulate for local tori ontop one Federal High Court ruling for Lagos state on di planned rally by supporters of di party candidate, for di state on 1 October, 2022. Tori wey dey circulate na say di court order di party and im supporters say make dem no gada for di Lekki toll-gate, and dem go only fit waka pass di place. Di rally suppose get up to 4 million pipo gada to show dia support. Howeva, one tok-tok pesin for di National Coalition for Peter Obi/Lawyers for Peter Obi Kelechukwu Uzoka for inside statement wey im sign on behalf of di group, clear am say no be wetin di judge tok be dat. E say di judgement of Justice Daniel Osagio wey sit on di mata dey in favour of di Labour party candidate and di ruling na say make di “Obi-Datti” rally hold for Lekki, Ikeja, Surulere and Festac. Oga Uzoka add say di “court order say make di Obi-Datti supporters pass thru and use di Lekki toll gate like evri oda citizen during di assembly but make dem no use am as assembly point.” One Adedotun Ajulo Esq and nine lawyers bin approach di court, say make di court ban di ""Obi-Datti"" rally October 1 rally for Lagos state, especially for Lekki toll gate. Part of di reasons dem drop be say di rally fit cause gbege for di state. Dem follow argue say di rally fit cause breakdown of order and if tins go like dat, for di Lekki-toll gate, e fit be like di EndSARS mata wey shele for October 2020. According to di statement, “di applicant counsel ask di court for total ban on di rally but di court disagree and rule against him, di court say if e ban Obi-Datti rally, then e go ban all political rallies and campaigns for Lagos. Wen di argument fail, di applicant come begin argue say di Obi-Datti rally na disguise for di #EndSARS protest wey lead to di destruction of properties and lives for Lagos. Di court again disagree and overrule di counsel, e remind am say according to di Lagos State EndSars Panel report wey im read, di violence start afta men in military uniform open fire on top unarmed civilians for di toll gate on di evening of October 20, 2020.”Di statement read. Di Obi-Datti defence team wey Alex Ejesieme SAN lead argue say no issue of violence don dey reported for di Obi-Datti rally wey don dey hold fir di kontri and outside di kontri. “Di EndSars commemoration no be di same as politically rally and shpow of support for di Labour Party and dia candidate.” Alex Ejesieme tok. E add say di supporters no get intention to block di toll gate or any ida public place wey pipo go use dat day. However Justice Daniel Osiagor also don order di Inspector General of Police to provide protection and security for di supporters of di Labour Party candidate for all di locations wia di rally go hold. Meanwhile, di Independent National Electoral Commission (INEC) don give political parties di go ahead to begin dia campaigns and rallies in preparation of di general elections wey go happun on 25 February, 2023." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd1l09rz24jo +politics Nigeria election: Senate wan make INEC begin do e-voting for future elections Di Nigeria Senate don begin plans to introduce bill wey go make Nigeria election body di Independent National Electoral Commission (INEC) to begin use electronic voting method for future elections. Di lawmakers also tell INEC to begin operate electronic database wia dem go send all di results for any election. E dey very likely say dis week, di Senate go begin do tok-tok ontop di koko of di bill wey dem wan use change di Electoral Act 2010. Di bill also state say INEC must transmit di informate of accredited voters inside di central data base once dem finish accreditation of voters wey dem go use card reader do. E-voting or electronic voting dey use electronic voting machines or computer wey get internet connection to cast and count votes. Sake of how transparent di system dey, pipo dey fit trust election process because dem believe say e dey secure and e no too get mistakes. Kontris like Namibia, Brazil, Belgium and some odas don adopt e-voting because of di benefits wey e get. E-voting dey also save time instead of to dey spend days and weeks to count votes before dem go announce di winner. House of Representatives member, Duoye Diri na one of di Nigerian politicians wey don call for di adoption of e-voting for di kontri. Im say di use of technology to transmit results from polling units go help reduce election jaguda, katakata and under-age voting. While some kontris dey embrace e-voting, some odas like Netherlands, Germany, Norway don drop am. Netherlands bin ban e-voting for 2007 afta tori of security wahala wit di machines spread evriwia. Some voters also get fear say hackers fit tamper wit di privacy of dia votes. While kontri pipo dey ginger for Nigeria to begin use e-voting, some oda pipo dey call for caution wit di adoption of di system. https://www.bbc.com/pidgin/50470852 +sports Nigeria D'Tigress beat Senegal to claim Afrobasket 2019 champions "Nigeria presido Muhammadu Buhari don congratulate di kontri basketball team afta dem beat Senegal for di Women Afrobasket 2019 wey happun for Dakar. On Sunday 18 August, D'Tigress retain di Women's Afrobasket title (from 2017) afta dem beat tournament host Senegal 60-55 in front of home supporters of more dan 15, 000. Dis na di second time in history wey di Nigeria women team go win di title back to back - dem win am for 2003 and 2005. Back for dia kontri, many Nigerians don dey congratulate di team. On Sunday evening, na so di kontri presido Muhammadu Buhari send im own congratulations ontop social media. Di American coach of D'Tigress Otis Hughley Jr tell BBC say im happy well well say women basketball don improve, say in fact im surprise for di kain game wey im see for di full tournament. ""Now I don get respect for dem, I no sabi say dem good like dis... many of di players here na pros,"" Hughley tok. Many of di Nigeria team members don dey togeda for many years now and dat fit be why dem see success again for di tournament. D'Tigress team member Evelyn Akathor hail Senegal as di home of African football but praise her team say dem tanda gigigba against di home fans. ""Senegal get good basket ball fans... but di tin wey epp us throughout di game be say we dey calm. We know say we come here to win but say we go play against di team, di fans, di refs.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-49352072 +entertainment BBNaija: Big Brother Naija Erica, Prince, Neo and Lucy do gbas gbos today for di lockdown house - See wetin cause dia quarrel "Kasala gas today for inside Big Brother season 5 lockdown house as di Head of House, Erica, her deputy, Prince and Neo clash with Lucy on top team selection. Di housemates para afta Lucy no wan gree accept to join di team wey di HOH and deputy put her sake of say Kiddwaya and Erica dey dat team. Erica wey be di Head of house tell Lucy say: ""You get bad attitude, You be di problem for every team."" Then Leo begin tell di housemates to clear Lucy and make her corporate instead of her to dey reject di group wey dem put her. ""Una no wan follow am talk, una dey condone rubbish."" dis na wetin Neo tok. But Lucy claim say Erica and Kiddwaya no want her to join dia team and two of dem don bin show her dis before. Di argument come serious sotey Prince wey be Deputy Head of House para and begin shout ""I don dey tell you dis thing ever since you waka enta do house, ever since we dey here. I be your friend, I go try to tell you wetin dey right for you. But then I no go keep quiet for your nasty attitude"" Prince tok. Lucy come dey ask prince wetin she do now? wetin she don do different dis time and dis na wetin Prince tell her; ""If you get attitude problem, make you keep am to yourself, we dey try to work on something...wetin you do different be say, you dey try to disobey di rules concerning Di task wey dem give us . ""Dem tell us to share ourselves into groups and di head of house and deputy decide to to do sharing but you decide to make your own problem our own problem."" Fans of di reality TV show dey clash sef with each oda concerning weda Lucy dey right or wrong." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54015478 +sports Liverpool vs Atlético madrid: Football fans yab Liverpool FC afta dem crash out for Champions League Football fans dey use Liverpool do yeye for social media with funny-funny comments and memes afta dem crash out for Champions League on Wednesday. Liverpool wey be di defending champions lose 3-2 to Atletico Madrid for Anfield and 4-2 on aggregate for dia round of 16 second leg match. Di first leg wey dem play for Atletico house for Spain end 1-0. Jurgen Klopp team start di second leg well, dem put di Spanish team under pressure for di first 90 minutes of di match and di pressure pay off with goal from Georginio Wijnaldum for first-half. For extra time Roberto Firmino score to make am 2-0 but di lead no last long. Two quick goals from Atletico substitute Marcos Llorente change di game before Alvaro Morata score for injury time to add insult to injury to send im team to di last eight of di competition. Many football fans no waste time to yab Liverpool wey don win dis competition six times for social media. See some of di funny memes and comments Di Reds go now focus dia attention on winning di Premier League title, dem dey gap second position Manchester City with 25 points with nine games to go. Already dis season dem don win di Uefa Super Cup and di Club World Cup title. https://www.bbc.com/pidgin/sport-51850411 +sports Super Eagles squad: Sunday Dare on Nigeria Super Eagles plan for AFCON in Cameroon "Minister of Sports Sunday Dare don tok say Nigerian Football Federation appoint interim coaches sake of dem no wan repeat mistakes of di past. Di sports minister for one interview say pipo go need go back to reason wetin di mistakes be, as di matter pass make dem just sack coach few weeks to major competition. Sunday Dare say wen pipo look around dem go see say oda kontries sef dey sack dia coach. ""Even last three weeks, Sudan bin sack dia coach"", Guinea too sack dia Coach few days ago. ""Di problem and di mistake no be to just sack coach, no forget say di preparation for those kind competitions no be four weeks sometin. ""Pipo dey make am look like say if we no get coach inside di next four weeks we no get team."" Sunday Dare say make pipo no forget say dis players dey play qualifiers, ""dis guys dey play for dia different clubs, some of dem no even dey join until one week to di tournament... Dem dey play EPL, LaLiga wherever dem dey, dem go just come in one week and go"". E add say e mean say di preparations dey go on as dem bin dey play for dia clubs, ""we bin don play friendlies as nation and qualifiers, dat one na preparation"". Sunday Dare bin explain say, ""Wen you let go of your coach or technical adviser ,my point be say you must get plan, you no fit just sack one coach and siddon dey look."" ""I fit tell you say we get plan sake of say wen we bin sack di coach we then make plenti announcements about di technical crew."" E add say; ""E go get new list of players pipo wey no make am before go dey there, tins don change."" ""We go see things work step by step, na di thing wey I dey expect be dat, pipo wey dey there now, abi make i say interim technical advisers don dey called to do there job wella. Oga Sunday Dare say pipo go see say dem dey try bring indigenous coaches and stars opportunity. E say dem dey work on one new team list as dem don see new players wey sabi play football well well, as some home based players go dey di list, e say dem go also announce new camp date. E say dem don begin search for new coach as no be say dem no dey do anything as per how dem go bring new manager for di player. Di sp[orts minister add say di NFF dey work seriously as dem dey brief am on di tins wey dem dey do, And im don charge NFF join bodi make dem get di best as dat na wetin Nigerians deserve and di kontri fit afford am so make dem no go get one cheap coach. ""NFF sabi say we get AFCON to compete, and di pipo wey dey in-charge now know why we let Genort Rohr go so dem know wetin dem dey find as dem no be outsiders. ""And dem know di terrain, dem know di DNA of our football so we suppose trust dem say dem go get di best."" E say na collective effort as we gas entrust di fate of di team to di hand of certain pipo , no be one person. E also add say im get hope say wit di team and stars wey di kontri get, dem go fit get us di result we want. Early dis month, Nigeria Football Federation bin sack Gernot Rohr and appoint Augustine Eguavoen, di current Technical Director, as Technical Adviser of Super Eagles on interim basis. Di Franco-German Gernot Rohr bin dey in-charge for more than 64 months. Rohr na di longest serving manager in di history of di Super Eagles." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59816112 +entertainment Teni: Di 'Billionaire' singer wey no like to use make-up """I just like to look natural - to me, na me fine pass , I like myself, I like my skin."" Na so Teni tok Nigeria musician, Teni, na one of di most celebrated afrobeats artists today. She don prove say e dey possible to dey successful and make you get fans wey like you even if you no follow do wetin oda female stars dey do. For her interview with BBC, she tok say she gatz to fight pressure from di industry to fit change herself. She dey conscious to be role model to plenti boys and girls wey fit dey deal with dia own images and self-acceptance. But some practical considerations dey too: ""To wear make-up dey stressful! Especially for Nigeria, ha, e dey hot! You go dey sweat. ""I remember one time wey I go Disney with my friend for Orlando during summer and e dey hot and my friend face look like mud! I come give her tonnes of tissue paper wey later turn to brown!""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51702422 +entertainment Diana, Giddyfia and Deji chop eviction from Big brother house "Fake Housemate, Deji as well as Diana Giddyfia don dey evicted from di big Brother Naija on Sunday. Tori be say Giddyfia eviction na im shock housemates pass. Deji na pharmacist, model and content creator. E been enta di house as fake housemate along with three oda housemates. E be di second fake housemate wey go leave di house afta Modella. Diana go dey missed by fans on top say dem dey call am di ""queen of di diary room"". Di last housemate wey comot di house Giddyfia bin tok wen e enta di house say e no go mind carry any girl wey catch im eye dey go. Na 28 housemates start di 2022 edition of BBNaija show. So far, e remain 14 real housemates plus two riders aka fake housemates wey go compete for di grand prize. Big Brother tell di housemates say na only di head of house get immunity, all oda housemates dey up for eviction on Sunday. Beauty chop disqulification soon after di show start. Di housemates wey don comot from di show na; Di show don do six seasons and don get six winners. Katung Aduwak, Efe Ejeba, Miracle Igbokwe, Mercy Eke, Olamilekan Agbeleshe and Hazel Oyeze Onou be di winners of di previous seasons respectively. Di show popular not only for di money and gifts di winners and participants dey enjoy, but also for di opportunities wey participants dey enjoy wen dem commot from di house. Dis season winner walk away with ₦100 million worth of prizes, including a cash sum of ₦50 million. Big Brother Naija na di Nigerian Franchise of di reality show Big Brother. Na reality show wia contestants dey live for isolated house and dey compete for a large cash prize by avoiding eviction by di viewers. Some analysts say BBNaija na Africa biggest reality show. Na MultiChoice Nigeria dey organise am. But di show dey draw criticisms say na big distraction for di youths and some pipo dey against am for not promoting 'morality'. But every year since e seven season run - during di months e dey air, e dey dominate social media conversations on Twitter, Facebook, Instagram and elsewhere. During di period e dey on, Big Brother Naija dey drive engagement and conversations for social media even as much as politics. Di programme dey air not only for Nigeria, but for 48 oda African kontries, to an average audience of 309 million viewers according to DSTV media sales figures. With peak viewing for di beginning of di programme, some eviction shows, and di finale." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c03mmp5vdlno +sports Afcon 2021 draw: Nigeria vs Egypt go open Group D, five oda times di two teams don meet As Nigeria draw Egypt, Guinea Bissau and Sudan for Afcon, many dey look forward to the Eagles against Pharaohs clash. Di Super Eagles and Pharaohs of Egypt no be strangers to di Afcon as both teams don win di tournament for combined total of 10 times. Dem go meet for Group D for next year Afcon and go try to top di group wey include Sudan and Guinea Bissau. Dis na five oda times di two African football heavyweight clash for football field. Nigeria 1 Egypt 0 (2019) - Dis one happun two years ago when Paul Onuachu goal after only nine seconds help Nigeria beat Egypt 1-0 for international friendly. Di goal wey many pipo say fit be di Super Eagles fastest goal for history na im settle di match wey dem play for di Stephen Keshi stadium for Asaba, Delta State. Nigeria 1 Egypt 1 (2016) - Dis na one of di most memorable meetings between di two teams because of how fans overcrowd Ahmadu Bello stadium for Kaduna to watch dis 2017 Afcon qualifier. Warri Wolves player at di time Etebo Oghenekaro na im first score for Nigeria before Mohammed Salah of Egypt break Nigerians heart by scoring late into di match. Egypt 1 Nigeria 0 (2016) - Dis na di return leg for di 2017 Afcon qualifier after di two teams play 1-1 for Kaduna, Nigeria. Di return leg for Cairo na one wey Super Eagles of Nigeria lose by one goal after Ramadan Sobhi score in di 62nd minute of di match for Hector Cuper men. Dis defeat mean say Nigeria fail to qualify for 2017 Afcon afta dem bin win am for 2013. Egypt 3 Nigeria 1 (2010) - Di two teams meet for Group C of di 2010 Afcon at dat time di pharaohs dey on fire with players like Ahmed Hassan and Mohammed Zidane. Na Chinedu Obasi first give Nigeria di lead but two goals from Hamid Moteab and Hassan see di Pharaohs finish as group winners. Nigeria 1 Egypt 0 (1990) - Di two sides jam for group of C for Algiers 90 Afcon and dis time na di Eagles end di game as winners. Di late Rashidi Yekini na im score di only goal in di 8th minute of di match for packed Stade Juliet Stadium for Algiers and di Egyptians no fit reply. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58255528 +entertainment Mercy Aigbe: 'I don close chapter on dis year Father's Day palava' actress reply Lanre Gentry "Nollywood actress Mercy Aigbe say her celebrating herself on Father's Day no suppose be anybody headache as she say she don close di chapter on dis year's Father's Day brouhaha. Di popular actress post dis one afta plenty back and forth messages between her and her ex-husband, Lanre Gentry. Mercy Aigbe and her estranged husband Lanre Gentry bin drag themselves on top social media on top who be di beta, responsible papa among di two of dem as di world celebrate Father's Dat dis weekend. Di ex-couples bin marry for 2013. Di marriage later scata and dem come divorce. For message she post on her Instagram page, she explain say she dey celebrate herself because she dey play di role of papa. She clear di air say she no dey call herself man but she dey play di role of father, so she fit celebrate hersef. Madam Aigbe for di Father's Day message she post for her Instagram page bin hail hersef and all oda responsible men. Mercy wey tok how she take dey take care of her two children say e no easy as she add join say if you be man and you no dey perform your responsibilities towards your children, then you no dey fit to be called a father. Her ex-husband for im Instagram page also congratulate himsef plus oda father's for di world. For message wey be like shade to di actress, im say some women go dey say happy father's day to themselves, wen dem no be good wife or mother's to dia children. But fathers always dey make dem happy wen dey house. E add say ""You no fit blame dem, dem no get good background, dem no get parents wey dey together, that na why dem no sabi wetin Father's Day be."" Dis post lead to more gbas-gbos between di estranged couples as dem backlash each oda on who dey take responsibility or who no dey take responsibility of dia pikin. Di actress say make her ex-husband stop to dey lie and even give di most irresponsible father award to her ex. Oga Gentry also say if Mercy like make e carry dia pikin go di moon, spend big money for im head. Im also don pay for anoda man daughter school fees before. Mercy Aigbe and Lanre Gentry get one child together and dis no go be di first time dem go come for each oda on social media. Mercy Aigbe na Nigerian actress, director and businesswoman. She dey popular for Nigerian Yoruba films. Dem born her for January 1, 1978 for Edo state. She come from Benin City, di capital of Edo state. She get OND for financial studies from di Polytechnic of Ibadan. She come further her education and graduate wit degree for Theatre Arts for University of Lagos. Mercy Aigbe start her acting career as she feature for some soap operas wey include di popular TV drama series Papa Ajasco. She join Nollywood industry fully for 2016. She don do many fems and collect plenty ogbonge awards." https://www.bbc.com/pidgin/57559348 +entertainment Big Brother Naija Dorathy and Lucy table Nengi, Ozo, Brighto oda housemates mata for BBNaija Lockdown - Day 23 highlights "Big Brother Naija housemate Dorathy don reveal wetin she and Brighto bin discuss during dia Saturday night party for di house ova di weekend. 'Brighto say im love me' dat na wetin Dora tell Lucy as two of dem lie down for di garden on Tuesday morning. She say Brighto tell her say im tell Biggie for Diary Room. According to her, she and Brighto bin get dia moment for di party wia she tell am say: ""I go like kiss you."" Brighto ask her wetin make her feel like dat she say she no know. But she say she know no weda na because of di kiss mata or im actually mean am. Dora and Brighto neva declare any feelings for each oda before now for di house, Lucy shock wen she hear di gist. Di only love interest wey dem don link Dorathy with for di house na Ozo, but she say two of dem na just friends and nothing more. Still ontop di Brighto mata she tell Lucy say two of dem agree say dem no go dey eat togeda, hold hands on dey play love like oda couples dey do for di house. Dora even share with Lucy wetin happun between she and Brighto last night tori be say, wen she bin dey go bath, Brighto ask her if him fit join her and she play along and agree. Meanwhile evicted BBNaija housemates Eric and Tochi follow BBC Pidgin tok for di first time afta im eviction from di Big Brother Naija Lockdown House. Eric admit say im bin no prepare wella compared to oda housemates wey still dey di house. Watch di full interview here: Di gist move enta Ozo, Dorathy and Nengi triangle and Lucy advise Dorathy to remove herself from di equation. She say na wetin cause di fight between herself and Lucy until e become personal. She say she wonder why Nengi go think say she no go get mind to tok anything for her face. ""Dem evict her new target on Sunday and she bin dey plan her next move. I only feel bad for Prince because im bin don dey fall and im be my friend,"" na wetin she tok. Dis week 14 housemates dey up for possible eviction na only di head of house Erica and her deputy Kiddwaya wey get immunity." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53742543 +entertainment Christmas message: Public holiday go dey for Nigeria, coronavirus lockdowns and wetin don change dis Christmas "Nigeria goment don declare 25 December as public holiday, di day when Christians for di world dey celebrate di birth of Jesus Christ. Di ministry of interiors for inside statement wey di minister Rauf Aregbesola sign, encourage Christians to follow di life of humility, service, compassion, patience, peace and righteousness wey di birth and Ministry of Jesus Christ signify as dat na di the best way to know Christ and celebrate im birth. He also tok say federal goment dey jolly wit Christians and all Nigerians wey dey di kontri and abroad for dis year Christmas and New Year Celebrations. Christmas season na one of di most joyous festival of di year as na dat time of di year wey pipo dey relax, jolly, flex, give gifts, travel, worship, visit friends and families. Di celebration dey always follow wit decorations, gifts, cakes, correct food, Christmas carol and holiday. Na also dat time of di year wen pipo dey come togeda to say bye-bye to di year, welcome di new year and pray for a peaceful and prosperous new year. But dis year own go dey different sake of di second wave of coronavirus wey don begin spread fast for di UK and across di world. UK and some oda kontris don introduce new strict lockdown, dem don ban kontris wey get high infections say make dem no come dia kontris so as to contain di spread of di virus. For November, UK scientists bin discover one new straint of coronavirus wey dey spread very fast pass di normal Covid- 19. Scientists confam say dis new form of di SARS-COV-2 virus wey dem call VUI-202012/01 get higher transmission rate pass di old variant and don cause increase in di number of Covid- 19 cases across di UK. Nigeria no dey left out from di second wave of di coronavirus as di kontri centre for disease control dey record high number of coronavirus cases recently. Dis don make goment re-introduce some measures to reduce di spread of di infection and dis don scata di plans wey some pipo get to ""Detty December"". a. Close All bars, night clubs, pubs and event centres, and recreational venues; b. Close all restaurants except those wey dey provide services to hotel residents; takeaways, home deliveries and drive-ins go dey closed; c. Restrict all informal and formal festivity events including weddings, conferences, congresses, office parties, concerts, seminars, sporting activities, end of year events go dey restricted to not more than 50 persons; d. Limit all gatherings linked to religious events to less than 50% capacity of di facility of use during which dem must observe physical distancing; mandatory use of face masks e. For gathering wey more dan 50 persons dey attend, any such events, dem must hold outside f. Public transportation systems no suppose carry passengers more than 50% of dia capacity in compliance wit di social distancing rules. g. Enforce compliance with NPI protocols especially the advisory on wearing of face masks in public spaces."" Christmas messages from Nigerian leaders, celebrities, families and friends na one thing wey dey always ginger di celebration and make am dey special. President Muhammadu Buhari dey always send message to greet Nigeria and jolly wit dem. Senators and plenty ogbonge pipo for di kontri dey also dey use di occasion to pray for Nigeria and give dem message of hope" https://www.bbc.com/pidgin/tori-55434769 +sports AFCON Round of 16: Osaze Odemwingie criticise defence tactics of Nigeria Super Eagles coach Gernot Rohr Former Super Eagles Striker Osaze Peter Odemwingie don criticise di defence tactics wey Nigeria coach Gernot Rohr dey use for di AFCON football tournament. 37 years old Peter Odemwingie tell BBC say oga Rohr for make Alex Iwobi captin of di team becos players like Mickel John Obi wey no dey play for Europe again no get interest again for football. But im still add say im mind no dey shake at all, unto any oda team for AFCON becos Nigeria performance for World Cup last year, show say dem fit face anyone, as long as balance dey between defence and attack. Nigeria go play Cameroon on Saturday July 6, 2019 for di Afcon Round of 16 game. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48872222 +entertainment Public Holidays in Nigeria 2022: Easter date, Labour day, Eid al-Fitr, bank holidays 2022 work dey resume from Tuesday 4 January, afta di new year day and Christmas festivities wey mark di end of 2021. Public Holidays in Nigeria dey up to 20 times for 2022, and for some Nigerians e already dey for dia minds to plan dia diary to joli di new year. And yes, many dey look forward to di better tins wey di year 2022 cari come including public holidays for di year. Dis holiday mean say banks, businesses, schools and goment offices no go dey open dat day. Dis na di likely public holidays wey di year 2022 carry for Nigeria and today wey be Monday 3, January 2022 dey among dem in continuation of di new year. If any public holiday fall for week end, dem go declare di following week day as Public holiday. Dis, according to how Nigeria Ministry of Interior dey announce public holidays over di years. Na to compensate for di weekend wey pipo dey already dey accustomed to rest from work. https://www.bbc.com/pidgin/world-59860601 +sports UEFA Champions League: Manchester City v Borussia Monchengladbach, Atlanta vs Real Madrid - players wey fit help dia clubs enter Quarter Finals "Raheem Sterling fit lead oda members of im squad to hrlp Manchester City enter di quarter final stage of di Champions League. Manchester City bin beat Borussia Monchengladbach 2-0 for di first leg of di round of 16 wey dem play for Puskas Arena in Budapest two weeks ago. Marco Rose, Borussia Monchengladbach boss ahead of di return match tok sey, ""e go need something wey pass extraordinary"" to beat Manchester City for di Champions League last 16 match."" Borussia Monchengladbach don lose dia last six games but Manchester City don dey unbeaten for dia five games against Borussia Monchengladbach for Champions League - dem win four, drawn one and dem score at least two goals for each of dia four victories. Anoda match wey go totori fans na di match between Real Madrid and Atlanta. Real Madrid don cari waka pass eight out of dia nine UEFA Champions League knock out matches wey dem win outside dia home. Dis na di second time Italian club, Atlanta go face Real Madrid for European competition. For dia first leg for Santiago Bernabeu, Atlanta lose to Real Madrid 0-1 courtesy of di strike by Ferland Mendy but wit Eden Hazard injury, di Spanish club go rely on Karim Benzema form to win di match as dis Zinedine Zidane team don struggle for dia home League. Meanwhile, Atalanta dey for beta position for dis Tuesday as Berat Djimsiti dey return for today clash including sey Gian Piero Gasperini men don win three of dia four games since losing to Real Madrid two weeks ago." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56404968 +sports Cape Verde vs Nigeria: Team news, Prediction, Time of di Qatar 2022 World Cup qualifiers "Nigeria Super Eagles don land Sao Vincente for Cape Verde ahead of dia Qatar 2022 FIFA World cup qualifying match. Di Super Eagles go play Cape Verde on Tuesday for di Estadio Municipal Aderito Sena, Mindelo stadium few days afta dem beat Liberia 2-0 for Lagos. Dem dey top of Group C wey get Cape Verde and Central Africa. Only di group winners go advance go di third and final round. Na for di final round dem go decide di five African teams wey go qualify for di World Cup finals for Qatar. Na 21 players Super Eagles travel wit go Cape Verde afta di UK-based members of di squad return back to dia clubs. Di reason why di UK based players no travel go Cape Verde na sake of di British goment strict regulations on red list countries on Covid-19, wey include Cape Verde. Those players wey dey affected include defenders Olaoluwa Aina, William Ekong and Leon Balogun. Forwards, Kelechi Iheanacho and Alex Iwobi also no dey unavailable. Midfielders, Oghenekaro Etebo, Wilfred Ndidi and Joseph Ayodele-Aribo don also comot di camp too. Super Eagles player wey travel to Cape Verde Goalkeepers: Francis Uzoho (APOEL Nicosia, Cyprus); Daniel Akpeyi (Kaizer Chiefs, South Africa); Maduka Okoye (Sparta Rotterdam, The Netherlands) Defenders: Chidozie Awaziem (FC Boavista, Portugal); Kenneth Omeruo (CD Leganes, Spain); Jamilu Collins (SC Padeborn 07, Germany); Abdullahi Shehu (AC Omonia, Cyprus); Zaidu Sanusi (FC Porto, Portugal); Valentine Ozornwafor (Sporting Charleroi, Belgium); Tyronne Ebuehi (Venezia FC, Italy); Midfielders: Chidera Ejuke (CSKA Moscow, Russia); Innocent Bonke (Malmo FF, Sweden); Kingsley Michael (Bologna FC, Italy); Adekunele Adeleke (Abia Warriors); Forwards: Ahmed Musa (Fatih Karagumruk, Turkey); Samuel Kalu (FC Bordeaux, France); Victor Osimhen (Napoli FC, Italy); Moses Simon (FC Nantes, France); Paul Onuachu (KRC Genk, Belgium); Terem Moffi (FC Lorient, France); Henry Onyekuru (Olympiacos FC, Greece) Cape Verde na one of those stubborn teams for African football. Na so football sabi pesin Deji Faremi tell BBC Pidgin. Although dia 1-1 draw against Central African Republic on Matchday bin dey disappointing, but results like dia 3-1 win over Cameroon for March na reminder of wetin dem dey capable of. E tok. ""I feel say dem go push Nigeria all the way, But Nigeria go grind out result wit wetin be dia second team"" . E tok Predictions - Cape Verde 1-2 Nigeria Di game go kick-off by 5pm West African Time and di match go show live on NFF TV and on NFF Website Captain Ahmed Musa go earn im 100th cap for Nigeria, if im play on Tuesday." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58466316 +sports African Games 2019: Falconets beat Cameroon to win gold Nigeria Under-20 women di Falconets beat Cameroon 3-2 for penarity shootout to win gold for di 2019 African Games for Morocco. Afta both teams play 0-0 for regulation time, Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie save three penarity for di shootout to help Nigeria win gold for di football category of di games. Dis na di third time Nigeria go win gold for football for di women category. Last time wey Nigeria women win gold for football na for 2007. Dis win alongside victories for oda sport events don see Nigeria win 40 gold medals so far for di Games. Currently, team Nigeria dey second for di medal table with 40 gold, 28 silver and 35 bronze. Egypt na dem dey lead di medal table with 79 gold, 87 silver and 63 bronze. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49521289 +health How hospital catch doctor wey allegedly rape pregnant woman during C-section "Police for Rio De Janeiro, Brazil don arrest one doctor afta hidden camera show say e dey allegedly orally rape one woman wey dey give birth. Reports say di video allegedly show how Giovanni Quintella Bezerra wey be anaesthetist dey put im private part inside di mouth of di woman wen doctors dey perform caesarean section on am. Anaesthetists na doctors wey dey administer anaesthetics to patients so dem no go feel pain during surgery. Wen di doctor finish, reports say im wipe di woman mouth wit tissue to erase evidence of di crime. Di alleged assault wey take place on Sunday, 10, July, 2022 bin reportedly go on for ten minutes afta Bezzera wait for di woman companion to komot from di room wit di new-born pikin. Tori be say officials of Hospital da Mulher de São João de Meriti bin don wonder why di doctor dey always give patients higher doses of Anaesthesia and na im make dem set camera wen di pregnant woman dey undergo C-section. Di 32-year-old doctor wey dem arrest on Monday allegedly give di pregnant woman higher doses of anaesthetics so im go fit do wetin im want do. Bezerra bin complete im medical training in anaesthesia two months ago. According to local news outlet Globo, anoda victim husband say Bezerra tell am to komot from di operating theatre during di birth of im son. ""Di guy wey dey give anesthesia tell me say make I leave halfway through. I neva even see di pikin and my wife don already sleep,"" di husband tok. E say im bin recognise di doctor face afta e see im face on television. Di Health Foundation of di State of Rio de Janeiro and di Secretary of State for Health release statement to condemn di act. ""We inform you say an internal investigation go dey opened to take administrative measures. Di Hospital da Mulher team dey provide full support to di victim and her family."" ""Dis behaviour constitute a crime, wey need to dey punished in accordance wit di legislation in force,"" di statement tok. Dem also say police dey investigate weda Bezerra get oda victims as dem praise di hospital workers for noticing di doctor odd behaviour. If dem find Bezerra guilty of di charge, im prison sentence go be between eight to 15 years. Meanwhile Bezerra lawyer claim say im neva obtain full access to di testimonies and im dey wait for am before e go fit comment on di mata." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c1v3ldvwd5go +entertainment BBNaija news now: How viewers vote Laycon, Dorathy to top five and evict Ozo from Big brother lockdown house Out of Laycon, Dorathy, Ozo and Trikytee wey bin dey up for eviction dis week, Ozo and Trikytee na dem get di lowest votes. Laycon top di poll wit 50.11%, followed by Dorathy wey score 26.88%. Ozo get 19.11% while Trikytee finish bottom wit 4.10%. As e be five housemates Laycon, Dorathy, Neo, Vee and nengi go stay for di house till day 71. But na only one of dem go waka comot from di house wit 85 million naira. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54228571 +business Why Nigeria central bank give airlines money to settle dia outstanding tickets sales Di Central Bank of Nigeria say dem don release $265 million to airlines to take settle outstanding ticket sales. Dem say $230 million bin comot as special Forex intervention, while $35 million comot thru retail SMIS auction. Di Director of Corporate Communications Department for CBN, Mr. Osita Nwanisobi, confam di release say di CBN Govnor Godwin Emefiele and im team bin dey concerned ova di kasala wey dey affect di kontri aviation sector. Oga Nwanisobi also add say dem no against any company to recova dia money money but wetin di Bank want na for dem to do am for orderly manner for di pipo wey wan do am. Dis dey come one week afta Emirates airlines say dem go suspend flights to Nigeria from next month becos dem no fitget dia money. Emirates airline for statement on 18 August, say di lack of forex don impact dia operational costs wey dey kontinu to dey pile up for market. Meanwhile Kenya airways say dem dey try collect $28 million from Nigeria, Ethiopia and Malawi. Dis na according to wetin di Kenya Airways Chief Executive Allan Kilavuka tell BBC. E tok dis one afta di airline say dem record loss of $82 million for di first half of 2022. Lack of dis foreign currency na part of di reasons why di airlines don dey unprofitable in recent years. Di International Air Transport Association (Iata) say e reach $1 billion wey kontris dey owe airlines across Africa wey fit create serious gbege to di aviation industry wey still dey sufer di effects of di Covid-19 pandemic. Normally, pipo dey buy flight ticket for dia local currency. Di reason na say foreign airlines dey required to sell dia services to customers for di local currency of di kontri wey dem dey operate. Di money gon now dey converted to US dollars and na so di airline home kontri go collect am. But shortage of foreign currency don dey hinder di arrangement. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz7d5p233rpo +politics Senator Abaribe explain why im ask President Buhari to resign """As tins e be for Nigeria now, no region dey safe as security problem full ground everiwia"" Dis na wetin Abia Senator, Enyinnaya Abaribe explain give BBC Pidgin ontop why im ask President Muhammadu Buhari to resign. But Goment tok tok pesin, Garba Shehu say di call by Abaribe for di president to resign dey foolish and e no represent di interest of di million Nigerians wey vote am to power. Oga Shehu say Abaribe no get right to make dat call wen e himself no di obey law and as e dey e neva fit produce Nnamdi Kano wey e help receive bail from court. However, di senator say for 2012, wen Boko Haram di attack di kontri Buhari bin ask di president den wey Goodluck Jonathan to resign sake of say im no fit tackle di mata and dat im go bring di change. E explain say wit di situation for di kontri now, di president imself don declare say di killi-killi dey surprise am and because e no get ansa, di best tin na for him too to go rest so dat Nigerians. Producer: Dooshima Abu" https://www.bbc.com/pidgin/media-51329155 +entertainment Baba Ijesha: Actor alleged rape case timeline, Yomi Fabiyi, Princess, Iyabo Ojo react Baba Ijesha suspected defilement case don reach one week since police arrest di Nollywood film actor. Actor Olarenwaju James AKA Baba Ijesha dey popular for mostly Yoruba and English movies. But now e dey trend for social media sake of alleged rape case wey involve a minor for Lagos, according to police. New informate come out afta Nigeria popular comedienne Princess react to pipo wey dey demand for di CCTV evidence. Princess for new video she post claim say di suspected sexual abuse happun for her house. Im matter become wetin Nigerians dey tok about since im arrest by di Lagos state police command Police for Lagos arrest 48 years old Baba Ijesha on Thursday April 22, 2021 and investigation start since dat time. As at Thursday 29 April, 2021 police tell BBC Pidgin say di actor Olarenwaju James AKA Baba Ijesha still dey dia custody. Since im arrest Nigerian film actors and entertainers begin argue over di mata: Iyabo Ojo, Biodun Okeowo, Tonto Dike and Femi Branch na some of those wey want make di Law catch up with Baba Ijesha Kehinde Adams, Yomi Fabiyi and some oda actors say make everi bodi dey patient make police finish dia work. Plenty Nigerians don also put mouth for di matter as dem ask dem ask police to finish di investigation on time make di matter go court. Police never fit carry Baba Ijesha go court sake of di strike by Judicial Staff Union of Nigeria wey make courts no dey function. Tok-tok pesin for di Theatre Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria (Tampan) Yemi Amodu for di statement wey dem bring out condemn di defilement case but say make everi body wait till court find am guilty. BBC Pidgin find out say dem never bail Baba Ijesha and investigation ontop di mata still dey go on. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56935415 +sports Check who Chelsea, Liverpool, Real Madrid go face for Champions League 2022/23 group stage Liverpool and Rangers go meet for di Champions League group stage, while Manchester City Erling Haaland dey set to face im old club Borussia Dortmund. Scottish champions Celtic dey di same group as defending champions Real Madrid and Chelsea go face AC Milan. Eintracht Frankfurt, wey dey make dia group stage debut, dey di same group as Tottenham. Bayern Munich, Barcelona and Inter Milan dey di same group. Group A: Ajax, Liverpool, Napoli, Rangers Group B: Porto, Atletico Madrid, Bayer Leverkusen, Club Bruges Group C: Bayern Munich, Barcelona, Inter Milan, Viktoria Plzen Group D: Eintracht Frankfurt, Tottenham, Sporting Lisbon, Marseille Group E: AC Milan, Chelsea, RB Salzburg, Dinamo Zagreb Group F: Real Madrid, RB Leipzig, Shakhtar Donetsk, Celtic Group G: Manchester City, Sevilla, Borussia Dortmund, FC Copenhagen Group H: Paris St-Germain, Juventus, Benfica, Maccabi Haifa Di matches go take place between 6 September and 2 November. Dis season Champions League final go take place for Ataturk Olympic Stadium for Istanbul, Turkey, on 10 June 2023. Matchday 1: 6/7 September Matchday 2: 13/14 September Matchday 3: 4/5 October Matchday 4: 11/12 October Matchday 5: 25/26 October Matchday 6: 1/2 November Round of 16 draw: 7 November All dey happun inside 2022. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c03zl093w8xo +business Nigeria Bureau of Statistics reveal how Nigerians dey spend more money on transportation "One new report wey di National Bureau of Statistics (NBS) drop don tok say Nigerians pay more moni for transport fare for March dan di previous month across different parts of di kontri. NBS drop dis one for inside one report about transport moni, wey im title be 'Transport Fare Watch (MARCH 2022)'. Dis na as state goment still dey struggle to pay minimum wage of 30,000 naira wey federal goment announce since 2019. Di report tok about all aspect of transport like bus journey witin di city per drop. Intercity, state route, charge per pesin; airfare charge for routes single journey; journey by motorcycle, wey pipo sabi as okada, and waterway passenger transport. Consumer inflation wey rise for February afta one fuel shortage gbege bin burst dat time helep push up di price. Di incident bin cause serious queues for filling station for weeks, and e make pipo begin find desperate option to fit get fuel. Di report say di average transport moni wey air passengers for particular routes single journey, bin rise by 4.43 per cent for month-on-month from N44,825.04 for February 2022 to N 46,810.62 for March 2022"". ""For year-on-year, di fare bin rise by 28.26 per cent (N36,495.41) for March 2021. ""Di average moni wey pipo wey dey do bus journey intercity per drop dey pay bin rise to N3,270.94 for March 2022, dis one show increase of 5.29 per cent for month-on-month if we compare am to di value of N3,106.72 for February 2022. Di moni, rise by 35.65 per cent (N2,411.29) for year-on-year, for March 2021."" Di average moni wey passengers pay for bus journey within di city per drop, di report show say e increase by 4.41 per cent for month-on-month from N513.72 for February 2022 to N536.35 for March 2022. Di average moni wey passengers pay for bus journeys inside city per drop bin rise by 42.17 per cent from N 377.27 for March 2021 to N536.35 for March 2022. ""For another category, di average moni wey pipo wey dey journey by motorcycle pay per drop bin increase by 4.22 per cent for month-on-month from N379.12 for February 2022 to N395.12 for March 2022,"" di report add. ""Also, for evri year, di moni bin rise by 45.57 percent from N 271.44 for March 2021 to N395.12 for March 2022. ""Di average moni for water transport (waterway passenger transport) for March 2022 bin drop to N890.03 as e show decrease of 2.53 per cent for month-on-month from N 913.13 for February 2022. On year-on-year, di fare bin rise by 10.10 per cent from N 808.38 for March 2021 to N890.03 for March 2022."" Fuel scarcity and pump price increase sef dey thereSince February 2022 wey Nigeria petroleum company NNPC bin carry bad fuel enter di kontri, kontri pipo never see one ogbonge relief from di kasala wey di error cause.Di shortage na im helep sky rocket transport moni and dis one don dey affect price of goods and commodities.Meanwhile, sabi pipo say more global increase for fuel price still dey come sake of di war wey currently dey shelle between Russia and Ukraine.Nigeria wey be Africa largest oil producer still dey rely wella on imported fuel sake of refinery wey no work and inflation rate don already rise to 15.7%. Di current price of petrol be N162/163 per litre for most major petrol stations and independent marketers dey sell am for N165/litre. Despite plenti promises wey NNPC bin give say dem go end di shortage, e still never show as transport moni still dey go up. On Wednesday, October 23, 2019, Federal Government afta plenti meetings wit di Nigeria Labour Congress finally announce to start to pay N30, 000 minimum wage to im workers. Around November last year, di Federal Government through di Chairman National Salaries, Incomes and wages Commission, Ekpo Nta say dem go soon begin monitor implementation of di National Minimum Wage Act 2019, wey increase di minimum wage for Nigeria worker from N18,000 to N30,000. Ekpo Nta, bin tok for one news conference for Abuja say dem go be interagency collaboration wey go gather evidence of compliance and wahala wey workers dey faceso dem go fit advise all employers, including goments at all levels. Dis one mean say as at late last year no be all Nigerian workers don dey receive di N30,000 minimum wage moni. Yet price of commodity for market continue to rise. Pipo wey dey affected pass for dis transport moni increase be low income earners wey dey yet to receive N30,000 minimum wage from di goment. Wetin be di Minimum wage for oda kontris?Nigeria minimum wage be N30,000 ($72) per month. Di minimum wage for Ghana change for January 01 2022 from 12.53 cedis to 13.53 cedis per day.Di United Kingdom National minimum wage from April first 2022 be £9.50 from 2021 £8.9 per hour, e rise by 6.6%.Di United States minimum wage dis year be $7.25per hour." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61233063 +politics US vice presidential debate 2020: Pence or Harris who win? plus oda takeaways from di argument "US Vice-President Mike Pence and Democratic running mate Kamala Harris do gbas-gbos ontop debate wey show live for TV wey millions across di world watch. Compared to last week presidential debate wey result to insult and di two candidates dey call each oda names, dis one between di two vice-presidential candidates behind their tables wey dey protected by plexiglass barrier, wey separate di two debaters 12ft (3.6m) apart sake of di coronavirus no too get all dat drama. Mr Pence no too interrupt as much as Trump do last week, but wen e do, Ms Harris dey give am back say ""Mr Vice-president, I dey tok, I dey tok."" Di two vice-presidential candidates do gbas-gbos ontop di issue of di coronavirus pandemic. Ms Harris accuse President Donald Trump of ""di greatest failure of any presidential administration in di history of our country"". While Mr Pence say Democratic nominee Joe Biden pandemic plan na ""plagiarism"" of di current White House own. For di 90-minute live debate wey happun for University of Utah for Salt Lake City, Ms Harris accuse Mr Pence and di president say dem deliberately mislead Americans about how serious di disease be. ""Dem know, and dem cover am up,"" she tok, as she add dem don ""forfeit dia right to re-election"". Mr Pence accuse di Biden-Harris campaign say dem dey copy-copy di White House pandemic strategy, e dey refer to di mistake wey end Mr Biden 1987 run for di presidency wen e plagiarise one speech by den-British Labour leader Neil Kinnock. Wen di moderator ask Ms Harris whether she go take approved Covid-19 vaccine wey dem go distribute before di election. Di 55-year-old California senator said she no go take any vaccine wey Mr Trump promote without di approval of medical professionals. Mr Pence, wey dey head di White House coronavirus task force, give am mouth back say: ""Di fact say you continue to dey undermine public confidence ontop vaccine if di vaccine come out during di Trump administration I think dey wrong."" Racial justice Mr Pence express shock at di killing of George Floyd for Minnesota. But e add say: ""There is no excuse for di rioting and looting wey follow am."" E point to one of im guests for di auditorium, Flora Westbrooks, one black woman wey dem destroy her hair studio was destroyed during di katakata wey follow Floyd killing for Minneapolis. He say Mr Biden and Ms Harris' claim say America dey systemically racist and say police get bias against minorities na ""great insult"". Ms Harris - say: ""Last week di president of di United States take di debate stage in front of 70 million Americans and refuse to condemn white supremacists."" ""Not true, not true,"" Mr Pence tok, as e argue say wen Ms Harris be prosecutor for San Francisco, African Americans dey more likely to be prosecuted for minor drug offences dan whites or Latinos. Ms Harris attack Mr Trump for paying $750 one year of federal income taxes as president, according to one New York Times investigation. ""Wen I first hear about am, I say, 'You mean $750,000?' And na like, 'No, $750."" Ms Harris also accuse Trump say e ""betray our friends and embrace dictators around di world"". Mr Pence say Mr Trump order operations wey kill Islamic State leader Abu Bakr al-Baghdadi and top Iranian general Qasem Soleimani Like with di presidential debtate, di vice-presidential candidates no gree ansa some questions directly. Mr Pence tow times ask Ms Harris whether Mr Biden gp expand di number of seats of di Supreme Court, wey don get nine justices for one century and a half, but she tok instead about Mr Trump current judicial nominee. Mr Pence too no answer questions about whether e go want im home state of Indiana to ban abortion, or how di Trump administration go provide medical insurance for sick Americans. Wen di debate moderator also ask dem about dia chances of taking over presidency, both candidates dodge di question." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54460060 +sports Anthony Joshua help fund British amateur boxing "World heavyweight champion Anthony Joshua don make one ogbonge donation to help fund amateur boxing for Britain - e say im hope say we neva lose di next generation of fighters. Tori be say dem don close some clubs and boxing no follow for di list of sports wey receive one £300m bailout for November. Joshua wey be British Nigerian give six-figure sum to di amateur boxing federations of England, Wales and Scotland. ""Without grassroots boxing, wey no go get Anthony Joshua,"" na wetin im tok. ""Di doors to di gyms dey always open to any pikin from any background,"" Joshua wey turn professional afta im win Olympic gold at London 2012, tell BBC sports editor Dan Roan. ""If I bin dey 18 again and I dey dis position wia dem close di gym and I know say e fit no open, my mind for spoil well-well. ""No be just financial help. I go try dey come to ginger di kids dem, bring my belts and train wit dem. ""I believe say in di next 10-15 years, you go see di leaders of tomorrow, but I hope say e no go take 25-30 years because we don loss dis next generation."" We go provide funds to di clubs wey need am badly. Gethin Jenkins, chairman of England Boxing, say: ""We dey happy and we thank Anthony for dis much-needed financial support and say e bring attention to di role and support di clubs offer for our local communities and wit di need for greater goment support to grassroots boxing clubs."" Although boxing no dey inside goment bailout last month, Sport England don distribute £2.5m to local clubs since di start of di Covid-19 pandemic. Joshua first become world champion for 2016 when him beat American Charles Martin to win di IBF title. Im most recent fight na ninth-round knockout of Bulgarian Kubrat Pulev for Wembley Arena for 12 December." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55413722 +politics Wetin to know about Ekiti State govnorship election "Residents of Ekiti state dey prepare to go to di polls to elect new govnor wey go take charge of di affairs of di state for di next four years. Di election go happun on Saturday 18 June, 2022, for di South West Nigerian state - e go be di seventh time since di kontri return to democracy in 1999 and since di creation of di state for October 1, 1996 under di military rule of General Sani Abacha wey di election go take place. Ekiti state no dey elect dia govnor wen most states for di kontri dey do and dis na sake of one electoral palava wey happun for 2009. For 2009, Appeal Court cancel election of Govnor Segun Oni afta im don rule for ova 41 months. Di court say na Dr. Kayode Fayemi bi di winner of di election and direct make dem hand ova power to am immediately. But INEC organise a partial re-run of di election wey see Fayemi become govnor for di state for 2010. Dat one na how di election time table take change for Ekiti state. Otunba Niyi Adebayo  na di first elected Civilian Governor for di state. Im rule between 29 May, 1999 – 29 May, 2003 under di Alliance for Democracy party (AD). Ayo Fayose become di next govnor between 29 May, 2003 – 19 October, 2006 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) to become di second elected civilian govnor of di State. Di state assembly later impeach Fayose on October 16 afta e chop accuse of money mago-mago say e embezzle funds, dem later replace am wit di state Speaker Aderemi but federal goment declare say di move dey illegal. General Tunji Olurin (Rtd) become di state administrator from 19 October, 2006 – 27 April, 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) afta dem declare state of emergency for di State. Chief Tope Ademiluyi  become Acting Governor for 27 April, 2007 – 29 May 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) Engr Segun Oni become Governor for 29 May, 2007 and rule till 17 Feb, 2009 under di flagship of di Peoples’ Democratic Party (PDP) before Appeal court remove am based on illegal returns of April 2007 elections. INEC later organise a partial re-run of di election. Rt. Hon. Tunji Odeyemi step in as acting govnor between dis period from 17 February, 2009 – 6 May, 2009 di under Peoples’ Democratic Party (PDP). Im become acting govnor wen one appeal court wey sit for Ilorin, Kwara State nullify Segun Oni election and order rerun poll inside 10 out of di 16 local councils wey dey di State. Dr. John Kayode Fayemi become govnor of di state for 16 Oct, 2010 – 16 Oct, 2014 under di All Progressive Congress (APC) Mr. Ayodele Fayose become govnor of di state for di second time for 16 Oct, 2014 – 16 Oct, 2018 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) Dr John Kayode Fayemi win Ekiti State election again for 15 July, 2018 to lead di state and im tenure go end for October . Di Independent National Electoral Commission, INEC clear 16 candidates from different political parties to contest di June 18 elections. Although e get up to five major contenders among dem . See di full list of di candidate , dia party and dia deputy: A       Reuben Boye Famuyibo with deputy Olumide Ezekiel Falana AAC  Ajagunigbala Moses  with deputy Olajide Oludele Oluwabunmi ADC  Oluwole Olumayokun Oluyede with deputy Popoola Hidiat Simbo ADP  Elebute-Halle Josephine Kemi with deputy Afuye Idowu Sunday APC   Abiodun Abayomi with deputy Oyebanji Afuye Monisade APGA Benjamin Olufemi Obidoyin with deputy Oluwafemi Anthony Faeji APM Fagbemi Peter Adegbenro with deputy Akinyeye Oluwatosin Eunice APP   Christiana Modupe Olatawura with deputy Ibukun Solomon Owolabi LP      Daramola Rowland Olugbenga with deputy Onile Ibrahim Yusuf NNPP Fatomilola Oladosu Abiodun with deputy Ade-Ajayi Oluwatoyin Hannah NRM Iyaniwura Tope Ifedayo with deputy Arowolo Kayode Williams PDP   Olabisi Kolawole Kolapo with deputy Olugbenga Kolade PRP   Agboola Olaniyi Ben with deputy Ogidan Tolulope Oluwatoyin SDP   Olusegun Adebayo Oni with deputy James Oladipo Owolabi YPP   Adebowale Oluranti Ajayi with deputy  Olaseni Nureni Babatunde ZLP    Adeolu Kolade Akinyemi with deputy Damilola Akintoye To elect di govnor of Ekiti State dem go use one modified two-round system to. To dey elected for di first round, one candidate must receive di plurality of di vote and over 25% of di vote in at least two-thirds of state local government areas. If no candidate pass dis mark, dem go do second round of election wey go hold between di top candidates. Di candidate to receive a plurality of votes for di highest number of local goment areas go win di election. Security and unemployment dey among di mata wey lead tok tok during di Ekiti state govnorship election debate wey BBC Yoruba organise for candidates wey wan contest for office of di govnor in di state. Di only female wey dey among di candidates, Kemi Elebute-Halle of ADP say di party get three steps to take so dem go fit strengthen democratic goment for di pipo Elebute-Halle say pipo wey bin dey goment bifo no do well. ""On security agenda, we get three principles for security mata. We go provide work for young pipo to reduce di challenge of security, i go provide public awareness programs, and work wit security pipo."" ""I don dey take care of pipo wit special needs bifo I contest. Debo Ranti Ajayi wey be candidate of di Youth Progressives Party (YPP) say im get di secret of how Dubai become popular, and Ekiti state go be like Dubai within four years. E say di tin wey surprise am be say, di current crisis for Ekiti be lack of moni and if anybody say dem go rebuild di city wit only money from Abuja, na lie e add. ""I be di only one wey fit pay di staff of Ekiti State."" Debo Ajayi say bifo di end of four years, Google and Microsoft go land for Ekiti state and Ekiti state go be reborn. Segun Oni of di Social Democratic Party, SDP say di tins e don do during im tenure go continue ontop education and health care. Oga Oni say im no fit say im no do well wen im rule, but im fit do more dan dat. Especially for di health care sector. Oluwole Oluyede of ADC political party, say e get knowledge and dey committed to rebuild Ekiti state as health sabi pesin. Oluyede tok say for health sector, moni dey important and im goment go work wit di private sector to reform Ekiti state health system. For security mata, e sa if job dey for young pio, greed to steal no go dey. ""We go re-establish vigilante, Autonomy go dey for local goments, we go establish state police and provide modern technology for security pipo."" Candidates of di Peoples Democratic Party, PDP, Bisi Kolawole, say im own focus be Agriculture, health, women advancement, and economic development be key areas of im goment. Kolawole say on security mata, e get plan to make sure say vigilantes work wit law enforcement pipo to stop security gbege. ""We don do am bifo, we go do am again if we enta."" Tensions dey usually surround elections for Nigeria sake of clash of interest. But di National Security Adviser, Babagana Monguno, don tok say di forthcoming off-season Ekiti State Govnorship election wey go happun for June 18 no go get violence, dis na according to local tori ppo for di kontri. Monguno give di assurance for one Inter-Agency Consultative Committee meeting on Election Security wey di  Independent National Electoral Commission (INEC) organise. Na Sanusi Galadima represent am for di meeting. Di NSA say security agencies dey monitor development for di South West state and from im discussions wit di Inspector General of Police, Usman Alkali Baba, e no get anytin to worry about." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0dvn371vxzo +health 'Coronavirus dey real, e happun to me'- Nigerian nurse wey catch Covid-19 One Nigerian nurse wey dey live for America, tell BBC about how she, her two pikin and husband dey cope wit Covid-19 wey she catch for work. Madam Chin Onu (no be her real name) follow BBC Igbo tok ontop phone on 24 March. Dis na her tori: My name na Chi Onu, I dey live for New York. For here almost everybody get di virus. I bin attend to one patient wey come to di hospital come treat anoda sickness, but afta test, we see say im get coronavirus. Because of how my job (nurse) be, I bin go do testing so as not to transfer di virus to oda patients wey no get am. My test come out positive, so I begin isolate. E don reach 13 days now since when result comot say I get di virus, but me and my family no experience any symptoms at all. I get two pikin and husband too, and I don touch well-well even before I find out say I get di virus. No one from my family show any symptom. But oda pipo dey wey di virus attack shake pass odas, like pipo wey get heart or lung condition, pipo with breathing problem, cancer patients, pipo wey dia immune system weak. Di virus dey hook dem well-well. Na di reason why I advise pipo not to panic, but make dem dey careful, because fear-fear fit lead to breathing problem and one fit even begin tink say im get coronavirus. If pesin wey im mind already dey up catch coronavirus, e fit dey serious. We see dis everytime. To chop beta food dey recommended during dis period: vegetable, orange, tangerine, all di fruit wey pesin fit see chop. Do u-turn when you see cold drink and ice cream, because dem dey bring condition wey fit make di virus ginger and grow. Even before I catch di virus, my family don dey use nose suck steam from hot water for house. I bin go for scan dis morning and di result show say my lungs and chest dey clear and di virus no reach any oda place for my body. In two days times I go go do test to check if I still get di virus, but I dey hope say I no go get am again as e go don pass 14 days. Coronavirus dey real, e happun to me, my colleagues and many oda patients I dey look after. E dey real. Pipo don die, many odas don survive. Make everybodi obey di order to stay for house and practise social distancing to prevent di spread of di disease. I no experience serious symptoms but that one no mean say I no fit infect odas wey fit get serious symptoms or even die. Dis na why we stay for house. But di tin be say, when test don come out negative for me, I go go back to my job, wey be to save lives. Dis tori na di personal experience of di pesin wey tok am. Dis no be medical advice or solution for any sickness. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52047665 +health Coronavirus update: Why Ghana no shutdown schools despite Covid-19 spread "Parents for Ghana intensify dema calls for govment to shut down schools sake of fears say Covid-19 dey spread. National Council of Parent Teacher Associations (NCPTAs) say de children dey live in fear and panic sake of dema dey hear of colleagues who dey catch de virus. Alexander Yaw Danso, President for National Council of Parent Teacher Associations (NCPTAs) talk BBC Pidgin say ""Ghana start as one, two, three cases but right now we catch 24,000. Dem wan make we wait until September?"" ""De worst part be say dem no dey test dem too… how dem go know if de students test positive for de virus when dem no dey test dem?"" he add. Tension start dey mount among parents after news broke say 55 people made up of students den teachers for Accra Girls' Senior High School test positive for Covid-19. Ghana Health Service (GHS) and Ghana Education Service (GES) release joint statement where dem reveal say after testing 314 people for de virus in de school, 55 test positive. GES say dem go continue to test, trace and treat cases for schools across de country to manage Covid-19 cases in schools. Cassandra Twum Ampofo, GES Spokesperson talk BBC Pidgin say ""we dey identify and segregate contacts from other students."" • Authorities distribute nose masks give students • GES intensify education on use of nose masks, sanitizers and social distancing • Students now dey attend dinning in smaller units so say dem no go experience overcrowding on campuses • Testing of suspected Covid-19 cases across de country. • Second mass disinfection exercise of schools • Strengthen counselling and psychological support over de Covid-19 fear National Council of Parent Teachers Association dey call for de shut down of school but according to de GES dis no be de best move at dis time. But GES Spokesperson, Cassandra Twum Ampofo, explain give BBC Pidgin say from how dem dey manage de situation sending dem home no be good move. Why Ghana no shut down schools? See di reason dem give. • Main reason students dey on campus be sake of dema final exams, after which all go return home • E no be safe to send students home now, rather keeping dem in schools go help manage any suspected cases of Covid-19 • Govment get opportunity to easily test, trace and treat students wey catch de virus while dem dey in confined places like school • Students dey come from all over de country, if authorities leave dem make dem go house, dem go fit infect dema communities • Most of de cases dem dey record for schools dey in incubation period, so e go be better say authorities go keep dem in school and treat dem • Once govment confine dem, e go be easy to contact trace, identify and treat students Despite calls from National Council of Parent Teachers Association, GES say despite dem get de interest of students at heart wey dem go finish de exams and return home to dema families." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53400328 +sports Crystal Palace vs Man City: Sergio Aguero and Ferran Torres goals push Man City close to Premier League crown Manchester City fit win di Premier League title on Sunday after two goals in di space of 83 seconds help dem win stubborn Crystal Palace. City go secure a third title in four seasons if second-placed Manchester United lose for home against Liverpool. After scrappy first half for Selhurst Park, Sergio Aguero thumped City ahead with clinical finish before Ferran Torres score from low shot. That end di resistance of Palace, wey dey 13th place. Roy Hodgson side get chances for di first half through Christian Benteke, wey flicked im header wide and bin get close-range shot wey City keeper Ederson block. But once City make their breakthrough when Aguero smash high into di net, plus another goal quickly follow by Torres neat finish, di result no come dey in doubt. Now di question na when, not if, Guardiola side go dey crowned champions once again after dem bin see Liverpool take their crown last season. As far as weeks for world of football dey go, City don enjoy one wey fit no dey even more perfect. Starting on Sunday when dem win di Carabao Cup final against Tottenham, and e continue on Wednesday with di impressive victory over Paris St-Germain for Champions League semi-final first leg, Guardiola squad perfectly round off a pivotal week. With di second leg wey dey come up on Tuesday, Guardiola shuffle e team as im make eight changes and dem initially no show any rhythm against a Palace side wey look solid. After Jesus see di ref rule out im close-range finish for offside, City go into di break wit no shot on target for di first half for di first time in 21 matches. Patience and second-half improvement wey serve as di key to City win for Paris prove imsef again. Guardiola demeanour bin dey buoyant and relaxed after im secure vital win, afta im don dey able to rest key players and seemingly avoid picking up any injuries. Now im go switch focus to complete di job against PSG on Tuesday and take City into their first Champions League final. https://www.bbc.com/pidgin/sport-56957867 +health Women for Jigawa contribute money buy car to carry pregnant women go hospital for one village wey no get "Some women for Bordo village wey dey for Jigawa state northern Nigeria don contribute money buy car wey go dey carry pregnant women go hospital wen dem wan deliver. Di women say dem contribute di money buy di car to solve di serious transport problem wey pregnant women dey face for dia village. From Bordo village to di nearest hospital wey dey for Jahun town na 29 kilometres and di road wey lead dey very bad plus di village dey secluded. Malama Halima Adamu na di woman wey lead efforts to make sure say dem buy di car and she tell BBC say dem start di contribution from every woman for di village wey chip in N1000. ""We start dis contribution with N1000 monthly wey women of di village dey pay and na so we continue until we reach N1 million wey we use buy di car. Now no matter how late in di night woman start labour, our car dey on ground to carry her go hospital make she deliver safely unlike before."" ""Anytime wey woman start labour, her husband go pay N2000, we go use N1500 for fuel and di remaining N500 go enter into our savings in case of future repairs for di car."" Chief of Bordo village Alhassan Haruna tell BBC say despite di car wey dey helep dia women, some pregnant women still dey deliver before dem reach hospital because dia roads dey very bad. ""Our roads no good at all and I dey beg goment to helep us. Because of bad roads some pregnant women dey give birth inside motor before dem reach hospital, even my wife give birth for road one time like that."" E add say if goment go fix di road e go make life additionally easier for di pipo. Dr Kabir Ibrahim na secretary of primary healthcare board for Jigawa state and e tell BBC say dem bin get over 120 cars for different villages wey suppose dey helep carry pregnant women go hospital but unfortunately over 100 don spoil. ""So wetin we wan do now no be to buy new ones but to convert di cars wey dey di villages for dat use. Wetin I mean be say goment go pay N4000 for any driver wey carry pregnant woman come hospital to deliver, dis na di approach wey wan use now."" Dr Kabir say dem don start to test run dis approach for three local goments of Jigawa state at di moment." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54100138 +business Buhari tell CBN not to sell forex for food importation "Nigeria President Muhammadu Buhari say e don draw ear give di kontri Central Bank of Nigeria to stop to dey give foreign exchange for di importation of food into di kontri. According to di president, dis na because of improvement in agricultural production and sake of say di kontri don get full food security. Di president tok dis wan wen e host All Progressives Congress (APC) govnors to Eid-el-kabir lunch for im hometown for Daura. Buhari add say di foreign reserve go be strictly to diversify di economy and not to encourage dependence on foreign food. ""No give one cent to anybody to import food into di kontri. We don achieve food security and we also no dey do badly ontop physical security."" Im tok. President Buhari wey say belle dey sweet am say young Nigerians, including graduates don dey explore agric-business, add say states like Kebbi, Ogun, Lagos, Jigawa, Ebonyi and Kano don already key into di federal goment policy ontop agriculture and dem dey make returns for rice farming, im encourage oda states to join di ongoing revolution to feed di nation. Meanwhile di Chairman of di Nigerian Governors Forum and Govnor of Ekiti state, Kayode Fayemi say di president sense of justice and fairness na major inspiration to di govnors on di way forward for di kontri. While di Chairman of di Progressive Governors Forum and Governor of Kebbi state, Atiku Baudu, commend di president ontop im bold steps to reposition di kontri economy. ""Di kontri dey more secure dan in 2015, di kontri dey more prosperous dan in 2015, beacuse you dey work for di majority of di pipo."" Im tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49340972 +politics Presidential Election Tribunal don begin sitting for Atiku petition against Buhari Presidential Election Tribunal don begin sitting for Nigeria main opposition candidate Atiku Abubakar petition against President Muhammadu Buhari victory for di February 23, 2019 vote. Atiku Abubakar petition before di Presidential Election Petition Tribunal na say di ruling APC party use mago mago win di election and say na im be di real winner. Na for Court of Appeal, Abuja di tribunal sitting dey take place. Tori be say na Justice Zainab Bulkachuwa and four oda Justices be members of di 2019 Presidential Election Petition Tribunal. Di odas include; Justice Abdul Aboki, Justice Peter Ige, Justice Joseph Ikyegh and Justice Samuel Oseji. Nigeria main opposition PDP post video of di sitting wia Justice Bulkachuwa say e pass 700 petitions from all ova di kontri wey don land di tribunal table. More details go land later... https://www.bbc.com/pidgin/tori-48201358 +politics Joe Biden pick Ron Klain as White House chief of staff "America President -elect Joe Biden don pick im veteran aide Ron Klain to be di White House chief of staff. Oga Klain don dey serve oga Biden since di 1980s wen im be Senator and later wen im be vice-president. As ogbonge insider for Washington, im don serve as Senior White aide to President Barrack Obama and as chief of staff to Vice-President Al Gore. Di work of di White House chief of staff na to manage di president everyday schedule and e no be political appointment wey need Senate confirmation. Ronald A. Klain na United States political consultant, civil servant, lawyer and member of di Democratic Party. Im serve as chief counsel for di Senate Judiciary Committee from 1989-92 wen Oga Biden be chairman. Imbin also work as advise and speechwriter during oga Biden 1988 and 2008 White House campaign dem wey no dey successful. Klain serve as chief of staff for oga Biden from 2009 to 2011 wen im be vice -president for Obama White House. Im later serve as ""Ebola czar"" under Obama during di spread of di deadly disease for 2014. Im na di Democratic staff wey don dey tey pass, im bin dey invovle for Bill Clinton presidential campaigns and work as adviser to John Kerry wen im try run for White House for 2004. Im don do presidential debate coach for Bill Clinton, AlGore, John Kerry, Barrack Obama and Joe Biden. Afta im work for oga Gore campaign, oga Klain work as powerful lobbyist for one ogbonge mortgage company and one drugmaker wey congress bin dey investigate. Im bin kwanta wit di new president-elect five years ago afta im give im full support to Madam Clinton campaign wen oga Biden, wey be vice-president den, still dey hope for di party nomination. ""E dey hard for me to do dat kain work afta Biden kpafuka,"" na so im write about di man wey in serve as chief of staff inside email wey im sent give Clinton presidential campaign chairman john Podesta for October 2015. Wikileaks na im reveal dis message and oga Klain refuse to comment about am wen tori pipo Politico publish am. Klain don since settle di mata wit oga Biden. During im presidential campaign dis year, President Donald Trump mention oga Klain many times as im attack Joe Biden. Im continue to refer to serious comments wey oga Klain bin make about how dem handle di H1N1 bird flu pandemic wey bin happun for 2014 to 2015 for US. About 12,500 pipo die from di disease even though e no reach Covid-19 deaths at all. Klain bin show for one panel of discussion last year say: ""We do everything wrong. And you know, 60 million Americans catch di H1N1 dat time. And wey just get luck say dis no be di biggest mass death for America history."" Trump use dis oga klain tok to take scata Biden argument say im go bring experience and competence to handle America current coronavirus pandemic. One old tweet wey bin cause plenty tok on Wednesday na di reply wey im post tor reply one atrticle wey tori pipo Vox bin do wit headline wey say: ""68% of Americans tin say dem rig election."" Dat na becos na so,"" oga Klain reply for di July 2014 post witout explanation." https://www.bbc.com/pidgin/54914708 +politics Asiwaju Bola Ahmed Tinubu: Nigerian politician Bola Tinubu colloquium in Kano lessons Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, former govnor of Lagos state for western Nigeria 69th birthday on Monday for Kano up north generate controversy. Bola Tinubu as many dey call am na big oga for di kontri ruling APC political party and im visit to northern Nigeria city of Kano to stage im colloquium get lessons wey you fit learn from. E get di way different pipo dey use eye see di visit; some say na political ahead of di 2023 elections while some say na move to unite Nigerians after north/soutj tensions of the last couple of months. Here na four lessons from Bola Tinubu colloquium in Kano: Among di things wey Tinubu visit cause for Kano na kata kata between ruling APC for di state and opposition PDP for di state wey former govnor Rabiu Kwankwaso belong to. Tinubu use im visit to go see Kwankwaso for im house and dat one sit well with some pipo for APC wey say na di former govnor beg am to come as e dey eye come back to APC. While Kwankwaso camp tok say dia oga dey very relevant politically na why Tinubu go see am. Na di mata some pipo dey still try settle as both camps still dey prove say di visit na about dem. Anoda major thing na how bad Kano weather' no allow some of Tinubu's closest pipo to attend di birthday celebrations. According to Senator Babafemi Ojudu, vice president Yemi Osinbajo, house speaker Femi Gbajabiamila, Lagos govnor Babajide Sanwo Olu all no fit attend because dem hear say Kano weather dey bad. Las Las na technology come to di rescue as all di aforementioned use video to send im dia birthday wishes to di APC leader. Some of di things wey Tinubu do while in Kano na to launch some projects wey govnor Abdullahi Ganduje do, among dem na di new office for di state anti corruption board. During di launching, Tinubu yan say e like di way Ganduje dey try wella to fight corruption for di state. Dat comment bring alot of discussion on social media about fighting corruption and what what is needed to fight am. For many di most popular from the visit and celebration na when di celebrant Tinubu tok say make Federal goment recruit 50 million Nigerian youths into Army. E tok about lack of jobs for di kontri and how criminal elements dey take advantage of dat to recruit young pipo into dia networks. Di Jagaban comment lead to plenti discussion for social media as some pipo say 50 million youth for Army too plenti. https://www.bbc.com/pidgin/world-56576231 +politics Sheik Nuru Khalid: Why we sack Digital Imam - Apo mosque chairman "Chairman of Apo Assembly quarters mosque committee, Senator Saidu Dansadau say mosque na place of worship and not place of attacking goment and na why dem decide to sack former Chief Imam, Sheik Nuru Khalid. For interview wit BBC Hausa, Senator Dansadau say im dey aware of all di abuse wey im dey receive especially on social media but e forgive anybody wey abuse am. Di chairman of Apo Assembly quarters mosque committee sack Sheik Nuru Khalid becos e no show remorse for di comments wey im make for im sermon. Dem sack Sheik Nuru Khalid on 4 April 2022 afta di Apo Assembly bin suspend am. On April 1st 2022 wey be Friday di 'digital imam' as pipo dey call Sheik Nuru give sermon wia e tok about di Kaduna train attack wey happun on Monday and goment failure to solve security wahala. “Even my family I don tell dem say make dem no worry about say pipo dey abuse me especially on social media. For me I don forgive everybody,” Senator Dansadau tell BBC Hausa. “Some pipo dey tok say I wan make goment give me position na why we sack Sheik Nuru Khalid while odas say I don collect money but God wey I dey serve see my mind.” “Our biggest issue with Sheik Nuru Khalid na because e say make pipo no comot to vote unless politicians assure dem of security and we feel say some pipo fit take advantage of those statements considering wetin dey happun for Nigeria at di moment e get pipo wey no wan elections to hold and for trouble to start.” “I personally siddon wit Sheik Nuru Khalid tell am say Nigeria dey in a delicate situation regarding election so we need to be careful, since you come dis mosque na im you dey attack goment but nothing don change, you need change style, make you dey tell Nigerians to return to God.” Di chairmo say during im personal meeting with Sheik Nuru Khalid e even use Quranic verses to tell am where God say make pipo change dia bad habits and return to am for dem to see changes for dia lives. Lastly di Zamfara state politician say assuming pipo wey dey abuse am and hail Sheik Nuru know di implication of pipo not coming out to vote dem for change wetin dem do. Meanwhile, di man in di eye of di storm Sheik Nuru Khalid for im own interview with BBC News Pidgin on Tuesday say as e be say dem use media suspend am from im position for apo mosque na why e dey also use media to tok im side of di tori. “Wetin I tok for my preaching for dat mosque na say we no dey happy with di president for wetin happun for di Kaduna train and oda insecurity, we observe say na only votes dem dey worry about.” “Dat na wetin vex dem to suspend me, for what na? for saying no to killing?.” About say im no show remorse after di committee suspend am, di sheik say e no commit any crime and see no need to show any remorse. Digital imam also tok say to open eye for am no go work for dis mata. “Instead say make dem call me say sheik we know say na true you dey tok but dey do am small small but dem wan open eye for me wey no go work.” Meanwhile, Management Committee of one new Jum'mat Mosque wey dey di same Abuja, Nigeria capital, don give di Imam new appointment. In two days’ time Friday to be precise di digital imam go lead im new congregation for Juma’at prayers wey muslims dey observe on Fridays. Di Sheik make di announcement two days ago during im Ramadan lecture. “I want to announce to una say we don get new mosque and by Friday we go launch am, so to pipo wey feel say dem go deny us platform dat wan no go work, we don get new Islamic centre.” “Just yesterday (Monday) a reverend call me to tell me say e play my Friday sermon for mosque for im church congregation to listen to, i read sermon for mosque and vex some pipo while some odas for church bless me for di same sermon.” “So my own na say i dey pity pipo wey dey vex instead of vexing for dem too.” Video of di imam na one of di most shared items on social media dis weekend across northern Nigeria wia e yarn say poor Nigerians no go comot to vote next year if dia lives no dey protected. “After every attack wetin we dey hear na ‘we condemn di attack’ dat word na wetin ordinary pesin suppose use but for goment wetin we wan see na action,” Sheik Nuru tok inside di viral video. “Pipo dey lose dia lives everyday and if e continue like dis poor Nigerians no go comot to vote for elections because dia lives no dey protected.” Still on di issue of insecurity, di imam believe say Nigeria goment and leaders don ""all fail"". ""I wan believe say all of us don fail to teach our children say life dey sacred. As parents, to teach your children say killing dey bad. ""Our community leaders fail, politicians fail, governors fail. Especially His excellency, di President of di Fedral Republic of Nigeria, you don fail us."" Less than 24 hours after im Friday sermon di committee wey dey oversee di Apo Assembly mosque announce di suspension of di imam for sermon wey dem say 'fit incite di public'. For statement wey chairmo of di mosque committee senator Saidu Dansadau send to BBC dem say di reason for suspending Sheik Nuru na because im sermon not only fit incite public but for also saying make Nigerians no vote for elections until politicians answer some questions for dem. “Wetin di imam suppose tell Nigerians na for dem to vote out pipo wey dem feel say no meet dia requirements but no be to tell dem not to vote at all.” Di committee add say to dia knowledge wetin di imam do before dem sack am now dey contrary to Islamic teachings and dem don appoint Mallam Muhammad and Mallam Abdullahi as replacements for Friday prayers and Ramadan month lectures." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61007831 +sports Liverpool vs Arsenal: Arsenal fans don tire for Emery "Arsenal fans want di club to sack dia manager Unai Emery afta dem lose on penalties to Liverpool for dia Carabao Cup match on Wednesday. Di Gunners troway 5-4 lead inside injury time as Divock Origi score late goal to equalise and take di game into penalties. During di penarity shoot-out, Dani Ceballos miss im take while Liverpool score all dia kicks to progress to di next round and knock out Arsenal from di cup. Match neva even end wen Arsenal fans begin para for Emery sake of di substitution wey im make for di match. Wit di scoreline 4-4 Arsenal coach Emery substitute Mesut Ozil for sometin wey make Arsenal fans for Twitter para as dem no fit understand wy Emery go comot dia 'best player'. For im defence, Emery say im decide to take Ozil off as na sometin wey dem don agree before di game ""for am to only play for dat amount of time."" Dis defeat to Liverpool dey come few days afta di Gunnaers troway two goal lead to draw 2-2 wit Crystal Palace on Sunday. Some fans just want di club to sack Emery while odas even see Mourinho as possible replacement for Emery in case dem sack am." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50245079 +sports Kun Aguero: Manchester City FC plan statue to honour Sergio Leonel Agüero del Castillo make fan ask 'what about Yaya Toure' "Manchester City club don confam say dem go honour Aguero, dia highest goal scorer with statue for di Etihad Stadium. Dis one come after announcement say e go comot di club wey im do for 10 years, when di season end. Many no go deny say di Argentina player deserve di accolade because of di records wey im don achieve wit di sky blues, but how many really know Aguero outside of di stadium. Di 32-year old wey grow up for very poor neighbourhood for Argentina na successful ahtlete today based on di 230,000 pounds salary e dey put for pocket every week. And im na papa to 12-year old Benjamin after im wife (Diego Maradona daughter) born son for am for 2009. Make we torchlight some tins wey you fit no sabi about premier league fourth highest goal scorer (181). Aguero di unique man Although im no too tall, e get stamina and e dey use all im body score. So far for premier league im don rise high to score 18 goals wit im head, 128 goals with right leg and although im no be leftie, e still manage score 34 with left leg. Among strikers im na one of di most dependable for di league. Aguero di Messi namesake Na “Lionel” Aguero parents bin wan give am as middle name if to say e dey di names register. But as e no dey, dem choose di version wey dey - ""Leonel"" to make im full name be Sergio Leonel Aguero. Same name Lionel Messi im correct friend, although different spelling. Aguero di Liverpool fan For 2006, before Aguero become popular for Europe, when tori pipo Munich TZ ask am about which league im dey eye, e reply: ""If I go choose league then e go be Premier League… I be Liverpool fan from time and my dream na to pla dia.” According to reports, dem say Aguero also mention former Liverpool forward Michael Owen as im role model. Aguero di singer Many pipo no sabi say im don wax record with Los Leales ontop song wey dem title: “El Kin Aguero”. Aguero join forces wit di Argentina band as dia lead singer for di hit song. Aguero di Legend Manchester City Manager Pep Guardiola hail Agüero as legend after he score hat-trick against Watford, wey make am use two goals gap di former club record scorer. ""Im na legend, and im na part of history in di club. Aguero (achievement) no need explanation,"" im manager bin tok. Since 2011 when e join dem im don collect 4x Premier League, 1x FA Cup, 5x League Cup, 3x Community Shield. Di only major cup wey Aguero never follow City win na Champions League, and na one wey many City fans go dey hope say e happun before e say final bye-bye. Aguero statue drama Aguero go join Vincent Kompany and David Silva as players wey go get dia own statue for di Etihad stadium. But many pipo don wonder why anoda player Yaya Toure wey play and do ogbonge tins for club, no get im own statue. In fact some enter social media to say Toure suppose collect statue before anybody because most of di trophies wey di club win between 2011 and 2018 na because of di Ivorian player. But odas remind world pipo say Man City don already honour Toure, even if na in a different way." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56577785 +entertainment Dsylexia - Disorder: Dyslexia explained as BBNaija Housemate Cross, Aisha Yesufu reveal "Dyslexia become topic of discussion for Nigeria social media space sake of wetin happun for Big Brother Naija reality show. One of di housemates, Cross, reveal im condition afta anoda housemates yab im thinking ability. ""Nine out of ten pipo smart pass me academically. I be 31-year-old. ""And most part of my life I dey always try as much as possible to get by academically."" Cross say im no sabi say im dey dyslexic till im cousin point am out. ""E dey sad to see dat part of me, but dat na my life."" Cross reveal am. Popular Nigerian activist Aisha Yesufu also share a social media post using di hash tag #Dsylexia. Yesufu bin dey dance wit her children for di video wit di caption ""Wen dem don tell you say your son no go fit go university. Wen you don prepare your mind say im no go be graduate and God prove you wrong!"". Di human rights campaigner reveal say her son get dyslexia. ""At 14 we carry am go one school for England, today at 22 im don become graduate."" Dis two don make pipo begin tok about wetin e mean for pesin to get di condition dem call dyslexia. BBC Pidgin enta research mode and dis na wetin we find out about am. Dyslexia na learning difficulty wey plenti pipo get. Science say one of of 10 pipo na im dey get am including adults and children. If pesin get dyslexia, e fit dey difficult for am to read, write or spell. E no dey affect intelligence and e no be disease or illness - na condition wey dem dey born pesin wit. Some pipo dey learn special techniques to help dem to live wit dyslexia on dia own. Odas fit need special support to help dem to do live wit di condition. Reports bin show say even though di condition dey common, e get plenty pipo wey no sabi say dem get get am. And dis one mean say dem neva go check wit doctor. Like many learning difficulties and conditions, no be everybodi wit dyslexia get di same experience. Some pipo fit dey struggle wit dia reading and writing, while another pesin wit dyslexia fit find maths more tricky. One experience wey dey common na make pesin dey find am difficult to remember things. Anoda way wey pipo wit dyslexia fit dey experience di condition na to dey see say words dey move about on di page wen dem dey to read. Dis onw fit make school work difficult to complete without special help and support. E get a lot of different ways wey children wit dyslexia fit manage dia condition. E dey also depend on dia experience of am and how e affect dem. Some children wey dey struggle to remember things fit use voice recorder to set reminders. Children wey dey get trouble to readi fit use one coloured overlay ontop of di text to help dem read. Odas fit benefit from special learning techniques or personal tutoring. Na differences in di language areas of di brain and di connections between dem dey cause dyslexia . E dey run in families and e fit affect pipo of any age from any kontri. Dem no fit cure am and pipo wey dem born wit am dey get am all dia lives. But dem fit manage dyslexia if di pesin get di right support . Pipo wit dyslexia fit become as successful as somebody without di condition - like successful businessman Sir Richard Branson. For one interview wey BBC II! do wit some pipo wey dey deal wit di condition, dem tok about wetin dem no go like make oda pipo say to dem. Some of dem no wan make pipo point am to dem say dem no like dey read Dem also no like make pipo dey tell dem ""You just need to focus"", dis one dey make dem feel say dem no dey try enough. 'Most of us like to go on our own space', one of dem tok. Oda talks dem mention na: ""You no go eva amount to anythin"" ""Why you dey always take longer for exams?"" ""Dont worry, you go grow out of am"" Tori be say dem no dey grow out of am but instead dem dey grow into coping and managing di condition." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58581174 +business How cost-of-living dey affect ‘Black Friday’ Retailers for Britain dey hope say pipo go spend money well-well to buy tins on ‘Black Friday’. Even though e dey happun wen cost-of-living don high well-well and di distraction from di ongoing Fifa World Cup. Britons go spend 8.7 billion pounds ($10.5 billion) over di Black Friday weekend wey go start from 25 November to  28 November). Dis prediction na according to research wey GlobalData for VoucherCodes  do - a rise of 0.8% year-to-year wey dey cause a big drop for di sizes  once inflation dey accounted for. Consumers don dey reduce dia spending as inflation dey increase. Inflation reach di highest for 41 years  wit 11.1% for October-eat disposable incomes. Anoda tin be say dem don start to buy Christmas tins early to help budget and finances. Dis year, consumers go use Black Friday, wey don become more of online event, to jump ontop cheap deals to buy tins and Christmas gifts, instead of di bigger, delayed purchases, na wetin consultants McKinsey tok. Dia research show say one quarter of UK consumers don already do dia Christmas shopping, while about one in ten dey plan to buy tins during Black Friday. Some consumers fit, get oda tins wey dey important to dem as Wales and England go play match on Friday for di World Cup. Retailers for Europe dey fear say di Christmas trading season fit be di worst in at least one decade as buyers no dey show face. While di money wey dem dey spend to do business no dey show any sign say e go reduce as dem dey squeeze di margins of dia profits (gains) Many consumers still dey prepare to buy tins for Black Friday. Idealo, di European price comparison portal, say 65% of online Italian buyers dey ready to buy one product during di event. For France, 70% dey plan to buy tins on Black Friday and Cyber Monday, according to research wey PwC France do. However, di Spanish pipo no too get interest, sake of say na just 24% of buyers dey plan to take advantage of Black Friday deals to start dia Christmas shopping. Dis na according to di Spanish Association of Mass Consumer Goods Companies. For United States, di National Retail Federation (NRF) don predict say holiday sales go rise small small dis year. Amazon (AMZN.O) don also predict dia slowest revenue growth for any holiday period for many years. For Britain di Black Friday buying and selling period dey important for Departmental stores groups. But some major retailers, including Marks & Spencer (MKS.L), no send di event.\nFor more dan 10 years since dem bring am come UK by Amazon, di worth of Black Friday to retailers still dey divide pipo opinion. Supporters say promos wey dem take time plan wit collabo wit global suppliers dey allow retailers to boost sales and maintain profit margins. Pipo wey no believe am dey argue say di discounts dey push Christmas sales go front wit reduced profits and e dey also reduce di willingness of consumers to pay full price again before di festivities. Black Friday na di day wey buyers fit buy some items for prices wey cheap well well pass di normal price between 24 hours. Na shops and oda retailers design am to encourage pipo to start to dey buy tins before Christmas. Na one of di very busy days wey pipo dey buy tins for di year. Some eco-campaigners say Black Friday dey bad for di environment as e dey encourage pipo  to buy tins wey dem no need. One 2019 report from di Green Alliance charity find out say 80% of evritin wey pipo buy during di Black Friday bonanza , e no dey stay long afta dem buy am, sake of say dem go troway am. Di report also tok say for di bargains, evritin no dey always dey as e look. One Campaign group say nearly nine out of 10 products wey dem sell on Black Friday dey available for di same price or cheaper earlier in di year. Some online shops and departmental stores don also start Black Friday promos too. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4n2rkp9vwvo +entertainment BBNaija Head of House 2020: Erica win HoH make Prince Deputy for Big brother Naija lockdown season 5 house Ngozi Nlewedim AKA Erica don become di new head of house of Big Brother season 5 afta she win di HoH Challenge dis evening. She pick Prince as her Deputy Head of House which mean say im self go chop immunity from eviction dis week. Dis go be di second time wey Erica dey win di position as head of house inside Big Brother Lockdown Season 5 as she bin don win am before for di third week in August. As Head of House, Erica don get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week. Her Deputy, Prince also get di same power and privilege to enjoy all di benefit wey HOH get. Dis latest win go make Erica di second pesin to win Head of House title twice afta Ozo. Later dis evening, di house mate go enta di diary room to nominate dia fellow house mates wey go dey up for eviction dis week. Already three pesin; Wathoni, Brighto and Tolanibaj na im leave di lockdown house on Sunday as e be say na dem get di lowest votes from viewers. https://www.bbc.com/pidgin/media-53975996 +sports Andrea Pirlo: Juventus say bye-bye to dia manager afta one year in charge of di club "Juventus don sack Andrea Pirlo as manager after im spend just one season in charge of di Italian club. Tori be say di 42-year-old na surprise choice to replace Maurizio Sarri last summer but under im guidance Juventus fail to win the Serie A title for di first time since 2012. Di Turin-based club finish fourth, dem only qualify for the Champions League on di last day of di season. Massimiliano Allegri dey expected to return for a second spell as manager. Allegri bin dey in charge of Juventus from 2014-19, im win five successive league titles and reach di Champions League final twice. Currently im no get club. Pirlo bin play 164 games for Juventus between 2011 and 2015 and win four Serie A titles for Turin afta im join dem from AC Milan, wia im spend most of his career and win two Champions League and two league titles. Im also earned 116 caps for Italy and help them to win di 2006 World Cup, im retire for 2017 afta im spend two years for Major League Soccer wit New York City FC afta im leave Juventus. Pirlo appointment as Juventus manager bin shock pipo although im win di Italian Super Cup and Coppa Italia, but e bin no dey enough to keep im job. Statement for Juventus website say: ""For di courage, di dedication, di passion wey you show every day, our thanks go to di 'Maestro', di coach and to Andrea, that really comes from di heart, as well as our good luck for di future that will surely be a wonderful one."" Dis na di latest managerial move among Europe big clubs first one na Antonio Conte wey leave Inter Milan and former Lazio boss Simone Inzaghi replace am and Zinedine Zidane also leave Real Madrid." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57279499 +sports Man United vs Atalanta: See prediction for di Champions League match Manchester United go host Atalanta for Champions League on Wednesday night, wit di hope to bounce back from dia defeat to Leicester City for Premier League . Di Reds Devils get three points from dia first two games for dis Champions League group stage and victory against di Italian side go boost dia chances of qualifying for di knockout rounds. Dis na wetin you need to know about di Champions League match. Manchester United neva really impress dis season na wetin football sabi pesin Bolarinwa Olajide tell BBC Pidgin. According to Bola e say huge pressure dey ontop United manager Ole Gunnar Solskjær head afta dia league defeat against Leicester on Saturday. Atalanta form no bad, one defeat in dia last six matches in all competitions. I dey back Atalanta to leave Old Trafford wit at least one point. Prediction: 2-2 How to watch di match? Di game go start 8pm West African time and e go dey live for Supersports on DSTV if you dey reason to watch am for Nigeria and Ghana. Harry Maguire and Marcus Rashford return from injury for di club defeat to Leicester City for weekend. In fact Rashford come in from bench to score United second goal. French defender Raphael Varane still no dey fit afta im get injury wen im bin play for France during di international break. Fred and Edinson Cavani go dey available again afta dem miss Saturday game. Aaron Wan-Bissaka go dey available too to play for United afta dem reduce im two-game suspension to one for di red card wey im collect against Young Boys. If Bruno Fernandes start, dis go be im 50th appearance for UEFA club competition. For Atalanta, Berat Djimsiti no go dey available afta im do arm surgery recently. Robin Gosens dey out for several weeks afta di thigh injury im suffer against Young Boys, while Hans Hateboer na long-term absentee. Head-to-head record These two clubs neva play each oda bifor for Uefa Champions League. As for Atalanta, dem don play English opposition on six occasions, against Liverpool, Everton and Manchester City, all in di last four years. Dem don manage to win three times, including for Anfield and Goodison Park, and dem don only lose twice. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58981059 +politics Key tins Sanusi and Tinubu tok for Kaduna Economic and Investment Summit Former Central Bank govnor of Nigeria, don question di amount of fuel di kontri dey use daily. Sanusi Lamido Sanusi, say di sixty six million litres of fuel wey NNPC claim say Nigeria dey use daily dey unbelievable. Na during di seventh edition of Kaduna Economic and Investment Summit e tok dis one. Ogbonge politicians and dignitaries attend di event wey happun for Kaduna north west Nigeria. Di event dey always hold during di political year of transition for di state and for di current administration to discuss economic development and investment opportunities wey dey di state. All Progressives Congress Party presidential candidate Bola Tinubu show face for di event. Dis na some of key tins wey Sanusi Lamido Sanusi and Bola Tinubu tok. Di former govnor of Nigeria central bank disagree wit goment on di kontri daily fuel consumption. “In 2019 officially, we bin dey import 40 million litres per day. In 2022, officially, we dey import 66 million per day. In three years, we increase our petrol consumption by 50%. Please tell me, na our population? Or di number of cars? Just ask yourself if e makes sense say in three years you increase your consumption of petrol by 50%,”. E advise goment to disband NNPC. On 2023 election e say: “Any politician wey tell you say e go dey easy abeg no vote for am”. E add say na either di politician dey lie or im no know wetin im go get. Di All Progressives Congress Presidential Candidate, make some big promises wen im become Nigeria president. Bola Ahmed Tinubu on Nigeria economy: say e go build vibrant economy wey go achieve double-digit growth. On Judiciary: E say im administration go ensure say di judiciary get financial and administrative autonomy,” On Security: E say im administration go use superior aerial technology to fight criminal and terrorist activities. E say im administration go use  technology to monitor and protect our pipelines, our power stations, our transmission and distribution networks, our sea and airports, our rail networks and odavital infrastructure. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c6pxx5v6e3zo +sports PSG enter toks wit Rashford, Aubameyang prefer Barcelona stay Paris St-Germain dey in toks with Marcus Rashford's representatives over di possibility of signing di England striker, 24, from Manchester United. (L'Equipe - in French) United get meeting schedule with Adrien Rabiot's mother and agent after dem agree fee with Juventus for di France midfielder, 27. (Fabrizio Romano) Manchester City dey interested in signing Atletico Madrid's Brazil left-back Renan Lodi, 24. (Telegraph - subscription required) Arsenal's Scottish left-back Kieran Tierney, 25, dey also among di names on Manchester City shortlist. (90min) Former Arsenal and Gabon striker Pierre-Emerick Aubameyang, 33, go prefer to stay for Barcelona than return to di Premier League with Chelsea. (Sport, via Metro) Nottingham Forest don make opening bid for Watford's Nigeria striker Emmanuel Dennis, 24. (The Athletic) Atalanta go rival Forest for di signing of Italy wing-back Emerson Palmieri, 28, from Chelsea. (Standard) Southampton Che Adams dey interested in move to Everton, but competition dey from LeedsUnited, Wolves and Forest for di Scotland striker, 26. (Mail) Everton hope to finalise deal to sign Guinea striker Serhou Guirassy, 26, from Rennes before di end of the week. (L'Equipe - in French) Manchester United's former interim boss Ralf Rangnick suggest say Stuttgart Austria striker Sasa Kalajdzic, 25, go reject move to Old Trafford. (Star) West Ham remain dey in toks with Paris St-Germainover a deal for Germany defender Thilo Kehrer, 25. (Express) Roma don cool dia interest in selling 23-year-old Italy winger Nicolo Zaniolo, who be target for Tottenham. (Standard) Everton dey keen to secure dia fourth signing of this week, with talks progressing well with Strasbourg's 28-year-old French striker Ludovic Ajorque. (Foot Mercato, via Express) Juventus dey close to finalising deal for Barcelona's Netherlands forward Memphis Depay, 28. (90min) Marseille don make contact with Manchester United over loan deal for Ivory Coast defender Eric Bailly, 28. (L'Equipe - in French) Bayer Leverkusen's Spanish winger Iker Bravo, 17, go join Real Madrid on season-long loan. (Bild - in German) Championship clubs Watford, Burnley, Blackburn Rovers and Sheffield United dey try to take Liverpool's Dutch defender Sepp van den Berg, 20, on loan. (Mail) Former Chelsea and Spain striker Diego Costa, 33, dey return to Rayo Vallecano after being without a club since terminating his Atletico Mineiro contract in January. (Marca) https://www.bbc.com/pidgin/articles/c253zve5rlwo +entertainment Erica: BBNaija Erica and Kidwaya receive huge welcome for Sierra Leone Salone Season 2 Erica and Kiddwaya, two former Big Brother Naija season five housemates, receive huge welcome for Sierra Leone. as dem land Lungi International airport wey dey Freetown, di West African kontri capital. Erica and Kiddwaya bin carry waka go Sierra Leone to attend di eviction party of one reality TV show, Housemates Salone Season 2. Di event go take place November 29, 2020 for New AYV Media Empire Complex on Tower Hill, Freetown. Di reality TV show dey very similar to Big brother Naija reality show wey Erica and Kiddwaya for meet come even get affair. Producers of di Housemates Salone Season 2 invite Erica and Kiddwaya sake of dia love story wey entertain viewers during dia stay for di Big Brother Naija lockdown house. As Kiddwaya and Erica land Sierra Leone, plenti pipo come out to hail dem. Report say even Sierra Leone TV stations air dia visit and shower dem with praises. Terseer Kiddwaya AKA Kiddwaya also tweet to inform im fans say im just land for Freetown and di kontri dey beautiful. Ngozi Nlewedim AKA Erica tweet video of fans wey dey welcome dem for Sierra Leone and write 'Thank you.' Just like Big brother Naija, organizers of Housemates Salone pick di housemates with different background from different parts of di kontri for dem to compete and win di minds of viewers who go later vote for dia favourite. And for di end of di show, di winner go carry go house di sum of Two Hundred and Fifty Million Leones (Le250M) plus get di opportunity to go on round trip to Dubai. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55113056 +politics Street Lights: Why Kano govnor appoint me special adviser- Salisu "Auwal Salisu a.k.a Kingdom wey Kano govnor Dr Abdullahi Ganduje appoint as special adviser on street lights tell BBC say di reason di govnor appoint am na because e dey always put eye for wetin concern streetlights for im area. Di special adviser collect im appointment letter few days ago and e go serve for di remaining tenure of govnor Ganduje. Kingdom add say anoda reason na because e try wella for di govnor during campaign and govnor Ganduje na pesin wey no dey forget pesin wey help am. ""Number one be say me na pesin wey get interest for street lights mata wella because e dey help reduce crime at night and also help pipo wey dey do night business."" ""Anoda major thing why govnor appoint me be say govnor Ganduje no dey ever forget pesin wey help am, i dey among pipo wey try for am during election time so na payback for sure."" Kingdom say in terms of education, after im secondary school na computer class e go wia e get diploma in computer operation but e dey plan to further im education. Kingdom also yan say wetin im wan achieve before di end of im tenure na to see say all di street lights wey dey Kano dey work everytime. ""Before na diesel we dey use for our streetlights for Kano but some bad pipo dey go steal am even di lights sef but now we wan change plan so dat all di street lights go get central unit."" ""Before di end of our tenure by di grace of God every street light for Kano go dey work all di time, we don start work already."" Dis no be di first time wey Kano goment dey get dis kain unique appointment. Dem also get special adviser to di govnor on graveyards matters. Di appointment of Kingdom as adviser on street lights cause plenti tok tok on social media with Nollywood star Kate Henshaw posting say now she don see everything for dis world after dis appointment." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51546511 +sports Man City vs Arsenal: See dia Premier League record plus predictions for di match Manchester City Kevin De Bruyne go miss Saturday game because of injury wey im get for international duty dis week wit Belgium. Raheem Sterling dey fit, while Sergio Aguero fit play for di first time since im do knee surgery for June. Arsenal £45m deadline day signing Thomas Partey fit make im debut. Meanwhile Kieran Tierney dey self-isolate afta Scotland team-mate Stuart Armstrong test positive for Covid-19 but dem neva ruled out yet. Di good news for Manchester City na say Raheem Sterling suppose dey fit. Di bad news na say Kevin De Bruyne go miss di game. City get striker Sergio Aguero dey recover from injury the way back afta his long lay-off, and dem need am fit and firing again. Im dey train but I no think say im go start dis game. Arsenal bin dey lucky for dia win over Sheffield United last time, but if City dey miss some key players di Gunners get chance. Prediction: 1-1 MATCH FACTS Head-to-head Manchester City dey unbeaten for nine Premier League meetings - dem don score at least twice in each of them - since dia 1-2 defeat for December 2015 wia dem (W7, D2). Arsenal fit lose seven league matches straight against di same opponent for di first time since dem do so against Ipswich between 1974 and 1977. Di Gunners only victory for dia past nine away league games against City na for January 2015. But, Arsenal win di most recent competitive meeting, wey Pierre-Emerick Aubameyang score two goals for dia FA Cup semi-final tie in July. Wednesday 17 June 2020 Sunday 15 December 2019 Sunday 03 February 2019 Sunday 12 August 2018 Thursday 01 March 2018 https://www.bbc.com/pidgin/tori-54581654 +sports Afcon 2021 draw: See how 24 teams across Africa arrange inside 6 groups "Time don reach for di Afcon 2021 draws wey go clear path for who go play who inside Africa premier competition for men's football. Di upcoming African Cup of Nations (Afcon) wey di Confederation of African Football (Caf) organise, go see 24 national teams battle for who go be di number team for Africa. Afta two postponement by Caf, di 2021 edition of di competition go finally hold between 9 January to 6 February 2022 for host kontri, Cameroon. Today draw for Yaounde Conference Centre go put mark di last part of di journey to di continental tournament wey Nigeria don win three times and Cameroon, five times. For March, di small Island nation of Comoros make history afta dem beat Togo to qualify for di competition for di first time ever. West African kontri Gambia also secure dia first appearance when Assan Cessay goal for di 62nd minute seal dia 1-0 win over Angola. In addition, to dis two di remaining qualified teams na: Algeria, Burkina Faso, Cameroon, Cape Verde, Comoros, Ivory Coast, Egypt, Equatorial Guinea, Ethiopia, Gabon, Gambia, Ghana, Guinea, Guinea Bissau, Malawi, Mali, Mauritania, Morocco, Nigeria, Senegal, Tunisia, Sudan, Zimbabwe and Sierra Leone. Caf seed di 24 qualified teams based on each kontri Fifa Coca-Cola World Ranking. Based on dis ranking, di top four teams - including Nigeria and Senegal - dey inside Pot 1 along wit di hosts, Cameroon and current champions Algeria. Di remaining 18 teams dey inside di remaining pots - 2, 3 and 4 - according to dia ranking in descending order. Di Afcon 2021 draw go happun on 17 August by 1800 GMT (6pm WAT). Di event host na BBC tori pesin Mimi Fawaz, wey no be stranger to dis kind role wit Caf as she don host Africa Footballer of di Year awards before. Six pots na im go represent di groups wey di di kontris go dey, from A to F. Di tournament originally suppose happen for June and July 2021 but Caf announce say di weather around dis period no go dey okay so dem move am forward to 9 January to 6 February 2021. On 30 June 2020, Caf moved di tournament for di second time to January 2022 because of di Covid-19 pandemic, although dem decide not to change di name from di official ""2021"" Africa Cup of Nations." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58227693 +health Coronavirus Update: Cameroon don confam total of 21 cases of Covid-19 outbreak "Cameroon don confirm total of 21 cases for Coronavirus, Covid-19 health Minister, as kontri pipo no gree respect hygiene Health Minister, Manaouda Malachie tweet dis morning say kontri pipo no di respect hygiene and goment e rules as reason why de infection di increase for Cameroon. ""Deh di put demselves and odas for danger"", Manaouda Malchie tok, as e announce 07 new Covid-19 cases for Yaoundé"". Health boss announce de 07 cases afta e tok yesterday say 03 passengers test positive out of 198 for Air France flight weh e land for Yaoundé Nsimalen airport for March 17. Now de number for positive cases don hit 21 from when goment announce 13 for press conference and one afta de presser. E nova bi clear who de seven pipo bi and how deh get de virus but goment di still call kontri pipo for bi double careful, respect hygiene. Cameroonians too di wanda why some pipo laik national assembly president, Cavaye Yeguie no respect quarantine, di parade e sef for national assembly everyday. Also why e go call meeting for MPs today weh goment say make more dan 50 pipo no gada for one place. Barrister Agbor Balla don condemn dis kana act say de national assembly boss no bi above de law. Health boss say deh de first two cases test negative and deh don go back for house even if deh di still monitor dem. Cameroon don set up place for check de passengers for multi-purpose sports complex. But most of all, make kontri pipo respect hygiene rules, wash hands wit soap, no touch nose eyes, no shake hands… If deh get catarrh, fever, headache, no di breath fain make deh call 1510 and deh go take care." https://www.bbc.com/pidgin/world-51976240 +health Coronavirus: Akufo-Addo release $100 million dollars for Ghana Covid-19 disease response plan "Ghana step up preparations and response plan to deal with coronavirus plus $100 million dollar financial commitment. Prez Akufo-Addo announce Wednesday night inside national address say he direct en finance minister make he release dis fund. Dis monies go ""expand infrastructure, buy materials and equipment, and public education"" Akufo-Addo explain. During de address Ghanaian leader also urge nationals make dem shun dey foreign travels for now. ""All of us for shun foreign travels, except de most critical ones until de virus matter finish"" President Akufo-Addo talk. Dis proposal to citizens dey come on de back of a temporary ban wey de Prez impose on public officials this week against all foreign travels. Ghana raise de preparation and response plan to coronavirus after all three neighboring countries, Togo, Burkina Faso and Benin record cases. Prez Akufo-Addo add say once World Health Organization (WHO) announce day de virus turn ""pandemic"" den e mean say as a nation dem for step up preparation. Ghana Health Ministry already set up 100-bed capacity facility inside one remote area to quarantine suspected cases plus some 5000 PPE kits. Some Ghanaians talk say dem no sure if de country make ready sake of health infrastructure be poor. But with dis monies, health officials leading de fight fit boost de country en preparedness and response plan against de pandemic." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51848582 +entertainment """Darasimi Mike-Bamiloye and Lawrence Oyor"" wedding: Bowl of Fire singer and Nigerian film actor pikin wedding announcement dey tortori pipo" """Darasimi Mike-Bamiloye di daughter of popular Nigerian movie maker, Evangelist Mike Bamiloye and Lawrence Oyor"" wedding dey go down dis October and dia love tori dey tortori pipo. One of di family contacts tell BBC Pidgin say Darasimi go dey tie di knot wit one 28-year-old gospel singer and son of di Late Rev. Dr Gomba Fortune Oyor. Di wedding go shele for Ibadan, Oyo state on 10 October, 2020. ""By di grace of God, di wedding preparations dey go on fine fine. Because of di kain big-big pipo wey go dey come di wedding and sake of say we gats obey goment policy, we go do crowd control. E go be strictly by invitation"", di family contact tell BBC Pidgin. ""Darasimi Bamiloye biography"" OluwaDarasimi Mike-Bamiloye (her full name) na graduate of English from Babcock University. Di daughter of Mike Bamiloye na drama minister, spoken word artist and more. Na Darasimi be di third and last child of di Christian Film makers Mike and Gloria Bamiloye wey dey popular for Christian movies wey pipo sabi as Mount Zion films.. Born 14 May, she serve her one year National Youth Service Corps programme for Kebbi State. She from Ilesa, Osun State (according to Wikipedia) wey be Yoruba speaking town for south west Nigeria. ""Lawrence Oyor biography"" Lawrence, apart from being a gospel singer, na graduate of Law from University of Ibadan 2013 set. Na Nigeria Law School-Yola e study to practice. Lawrence Oyor from Ibadan, Oyo State, dem born am 16 June, 1992 and e dey speak English, Yoruba language and Ibibio-Efik" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54288175 +business Telecoms tax: Nigeria new tax on phone calls explainer "Nigerians go soon begin pay ""telecoms tax"", dis na tax on top phone calls wey pipo dey make. Di telecommunications tax dey inside di National Health Insurance bill 2021 wey don become law. President Muhammadu Buhari just sign am into Law last week. Nigerian Communications Commission tell BBC Pidgin say dem still dey torchlight di Law. So how e go affect you? Na di full explanation dey inside dis tori. Di tax na part of goment way to raise money to fund di health insurance scheme of di kontri. Di money wey go come out from di deductions dey go di Vulnerable Group Fund, as part of health care reforms. Vulnerable Group Fund be money wey Buhari goment set up for Nigerians wey dey weak and helpless alias poor. Na under Section 26 subsection 1 (C) of di act di provision dey - e say goment go take one kobo per second of evri telephone call. Dis mean say, for example, if your telephone service provider dey charge 11kobo per second, evri one kobo na charge for health care levy. ""Di source of money for di Vulnerable group fund include basic health care provision to di authority, health insurance levy... ""...telecommunications tax, not less dan one kobo per second of GSM calls."" di act tok for wetin BBC Pidgin don see. E neva clear if di Law don already take effect as president Buhari don sign am. Nigerians also neva begin tok weda dem don dey see di effect of di deductions for dia telephone calls. Ikechukwu Adile, NCC Head of Corporate Affairs say di agency still dey study di di new act wey dey dia table. ""We still dey look di Law and we go make statement to Nigerians wen we dey ready,"" e tok. Tax on telephone calls go affect mostly poor Nigerians wey dey struggle already, na so one sabi pesin tok. Hamzat Lawal, founder of Follow the money, say citizens no dey feel di impact of di oda taxes wey dem dey pay since. E say: ""No tax dey healthy or unhealthy because e dey help citizens support goment to build public-use infrastructure."" ""As well as transform different sectors like health and education."" Lawal also say Nigerians no dey benefit from di tax dem dey pay already. ""Reports say teleco operators dey complain about di policy wey mandate citizens to pay extra 5% on phone calls go make tins harder on citizens. ""Wit di current devaluation of di naira and inflation, pesin fit argue say na bad timing to further burden di population"" ""Especially wen little or no tangible results dey for all taxes citizens dey pay."" Hamzat Lawal say as long as paying tax no contribute to community needs, every citizen, including less privileged go dey seriously affected." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61576453 +politics US presidential election results: Donald Trump give condition to leave White House "US President, Donald Trump don give condition before e go leave di White House even though e go dey hard for am to agree say Joe Biden win di election. Dis na di US presidential election results latest update since afta Trump begin drag say im no go accept defeat. Oga Trump say im go leave di White House if di Electoral College officially confam Joe Biden victory when dem meets next month. On Thursday, tori pipo ask president Trump weda e go agree to leave di White House if e lost di electoral college vote and e reply say; ""Certainly I will, certainly I will and you know dat."" But e also add say ""if dem pick [elect Joe Biden], dem make mistake"", and suggest say e fit no ever accept defeat. ""E go be very hard thing to concede because we know say big fraud dey di election."" President Trump tok. Di president don bin refuse to accept defeat for di 3 November vote, and tell reporters say e go dey ""hard"" to concede. E also repeat im claim of voter fraud wey no get prove once again. Joe Biden pass oga Trump with 306 votes to 232 under di electoral college system wey dem dey use take pick US presidents. Di tally dey far more than di 270 wey Biden need to win, and oga Biden also lead di popular vote by more than six million. Electors go meet next month to formalise di vote, as Joe Biden dey prepare for im swearing in as president on 20 January but Trump no tok weda e go attend oga Biden inauguration. Under di US electoral system, voters no dey directly choose di next president. Instead, dem go vote for 538 officials, who dey allocate to American states based on dia population size. Di electors almost always dey vote for di candidate wey win di most votes for dia states, and although e dey possible for some to disregard di voters' pick but no result don ever changed dis way. President Trump and im supporters don file alias lodge plenti-plenti legal challenges ova di election, but most of dem don dey dismissed. Early dis week, oga Trump finally agree to allow di formal transition to President-elect Biden team to begin, afta several weeks of dragging. Di decision mean say oga Biden dey able to receive top security briefings and access key goment officials and millions of dollars in funds as e dey prepare to take ova on 20 January." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55097686 +sports Manchester City: Raheem Sterling dey go Real Madrid? "Foto show England international player Raheem Sterling wit Real Madrid shirt afta dem ask am about im future wit Manchester City. ""Wen you see di white shirt you go know exactly which club e dey stand for, dem dey very big"" na wetin Sterling tok. City go play Real Madrid for di last 16 of Champions League, di first leg go happun for Spain on Wednesday. Di return leg na for Etihad Stadium for Manchester on 17 March. Dis dey come afta Uefa ban Manchester City wey be di current Premier League Champions, from European football for di next two seasons. Di ban dey start next year - 2021season. Na because dem find out say dem find out say dem rules wey relate to how much money dem dey allowed to spend. Dat na why tori dey fly upandan weda di City top players go leave. Im tell Spanish tori pipo AS: ""Right now I dey City and I dey really happy. But I go say Real Madrid na fantastic club."" Dem ask am weda im go like play for Real, im tok say: ""How I go carry answer dis one? Di camera dey live or e just dey take pictures?"" Manchester City manager Pep Guardiola say im players dey ""free to tok as e be. We no dey here to tell them wetin dem need to tok "". Sterling don score 11 goals dis season." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51617574 +business World population don hit 8 billion - See pipo wey make am 5th, 6th and 7th billion years ago Na Tuesday November 15 2022 di world population hit 8 billion according to United Nations, 11 years after we reach 7 billion. According to di UN, afta di big increase wey happun last century, world population dey gradually slow down at di moment. Dem say e go take 15 years from now for di world to hit 9 billion pipo while 10 billion no go happun until 2080. Di UN admit say na difficult tin to accurately give number of pipo for di world but by a year or two di sums go comot. But November 15 na di best estimate for di 8 billion line to dey crossed. For years wey pass, di UN select babies to serve as di 5th, 6th and 7th billion pikin for di world, who be dis children and wia dem dey now. Dem born Matej Gaspar for 1987 for di city of Zagreb wey dey inside Croatia.\nMinutes afta dem born am na im politicians and cameramen surround am to see am. Dem select Matej as di 5th billion pikin for di world na wetin cause di rush by top pipo to see am. British UN official Alex Marshall say di projection at di time show say na July 11 1987 di 5th billion pesin go enta dis world na why dem decide to choose di ‘5th billion baby’. Wen oga Marshall explain di idea to demographers wey dey work for UN dem no happy and dem ask why dem go select one baby as 5th billion pesin. “So di idea na to put face to di numbers wey pipo dey always hear about.”\n35 years later, Matej Facebook profile show say e still dey live for Zagreb, emarried and dey work as a chemical engineer, e no gree speak to BBC. Since 1987, anoda 3 billion pipo don enta dis world but projections for di next 35 years show say na only 2 billion pipo go enta di world wey show say population growth don slow down. Adnan Mevic wey dey stay Bosnia-Herzegovina na im be di world 6th billion baby and dem born am for di year 1999. E dey stay one of di kontris wey get one of di slowest population growth as projection show say in di next 50 years di population dia go remain only half of wetin dey today. Low fertility and high migration to oda parts of di world na why Bosnia dey face dis problem. Adnan wey dey stay Sarajevo with im mum Fatima get masters for Economics and dey struggle to get work. Sadia Sultana Oishee wey dey stay Dhaka for Bangladesh na im selection as di 7th billion baby. Dem born Oishee for 2011 and na she be di youngest for her family. Dem born her just after midnight and just like Matej camera crew and pipo full to welcome her to di world wey sweet her parents for belle. Di father bin dey hope for boy as e don already get three oda daughters, Oishee say she wan become doctor and di father say e go try im best to make her achieve  her dream. According to di United Nations, more dan half of di population increase wey di world go witness from now till 2050 go come from eight kontris. Di kontris na Nigeria, Pakistan, India. Ethiopia, Congo, Egypt, Phillipines and Tanzania. Di UN report also tok say for Nigeria and most sub saharan Africa plus part of Latin America and di Caribbean, di share of working age population (25-64yrs) dey increase. Dat increase na opportunity for economic growth according to wetin di report yan. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c3g83grglero +entertainment Motara video: Interesting facts to know about social media influencer wey do long throat for child beggar "Nigeria social media influencer, Omotara, popularly known as Motara bin enta kasala afta di video of wia she dey do longer throat for one child beggar surface on social media. Motara na popular socialite, wey her social media posts dey totori her fans. For interview wit BBC Pidgin, Motara reveal say she be 25 years of age. She grow up for Ibadan, South West of Nigeria. She also tok say she study microbiology for di Polytechnic of Ibadan. Motara bin tok about her family say wen she be six years old, her papa abandon dem and her brother. ""My mama dey hawk for Ogunpa market to take care of me and my kid brother, she no get anybody, nobody!!"", she tok. ""She bin dey take care of us , HAWKING o, we no get anything but we bi dey satisfied"" ""We bin dey in POORverty, no be poverty"", she add am. Omotara reveal for one long post wey she write on her social media page, say dem bin dey live for one room apartment wia her mama rent for olomi academy for Ibadan. She say bin suffer depression during her final year for school wen she need money to complete her project but her uncle wey promise to send her money die. "" I bin wan run mad, I dey angry wit di world, at everything,, I become suicidal"". Motara say even though things don become better for her family, her 56 year old mum still dey hawk. Days afta she tok about her family and how she bin grow up, di video of how Motara take mock a child beggar surface for social media and dis make pipo para. Although she bin don apologise say she regret her action. ""I just wan apologize because evritin just dey happen fast fast. I no even know what else to do. I don go look for di girl. I go on Monday, Tuesday, Wednesday and I go still go there today"", she tell BBC Pidgin. Sake of di viral video, she lose her endorsement job wit one local soda drink company wia she bin dey work as dia Public Relation Officer (PRO). Di Brothers Keeper energy drink company insist say wetin Motara do dey against dia beliefs and vision, say e dey 'dehumanizing and degrading'." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55089580 +sports Zouma gbab 180 hours community service for kicking and slapping im cat "Court don order West Ham United defender Kurt Zouma to carry out 180 hours of community service afta e plead guilty to kicking and slapping e cat. Dem also ban di 27-year-old from keeping cats for five years. Im admit to two offences under di Animal Welfare Act for one hearing for Thames Magistrates' Court in May. Court also order Zouma brother Yoan, wey play for Dagenham and Redbridge, to carry out 140 hours of community service for di 15-minute hearing.\nDem bring e case following one RSPCA investigation. Yoan admit one count of aiding, abetting, counselling or procuring im older brother to commit an offence. ""Both of you take part for dis disgraceful and reprehensible act wit dis pet cat,"" di district judge Susan Holdham tok. ""Di cat dey look up to you to care for im needs. On dat date for February you no provide for im needs. You must be aware say pipo look up to you and many young pipo dey aspire to emulate you."" Yoan, 24, film di incident for im older brother house and post am on Snapchat wit 'laughing' emojis on 6 February. For di video, dem fit see Kurt could dey kick di Bengal cat across im kitchen, before e throway shoe at am and slap am for head, di video also show as e dey tok ""I swear I go kill am"". Di court hear say Yoan, wey Dagenham and Redbridge don extend im contract get 80 followers on Snapchat, and only five accounts view am before e delete di video few minutes afta e post am. Dem also order Kurt to pay court £8,000 in addition to di 12-month community order. Di hearing for May hear say West Ham don fine di player £250,000 and im don lose one ""substantial"" sponsorship deal wit sportswear firm adidas. ""West Ham United wise to make clear say we condemn in di strongest terms any form of animal abuse or cruelty,"" one statement from di Premier League club tok afta di sentencing. ""Dis kain behaviour dey unacceptable and e no dey in line wit di values of the football club. ""Within 48 hours wey di video comot, we fine Kurt di maximum available to di club. ""Every single penny of dis money don dey wit a number of deserving charities, all dedicated to animal welfare."" Di Hammers add say: ""Kurt admit at di earliest opportunity say wetin e do dey wrong. Im also apologise without reservation. ""We hope by now say di court don reach im decision, everyone go allow Kurt di chance to learn from im mistake and move on.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz73k86r6z7o +entertainment Whitemoney BBNaija ex-housemate exclusive: 'Na poverty carry me go Big Brother house' "Winner of Big Brother Naija 'Shine Your Eye' Season 6, Whitemoney, AKA Hazel Oyeze Onou don tok about in journey for inside di BBNaija house. For exclusive interview with BBC idgin, he follow tok im money situation before im enta di house afta tori say im get shoe factory for house comot. Im explain say, ""na poverty carry me come BBNaija house. I dey hustle normal but dat one na business, you fit get 10 million naira and one million go be your profit. E no mean say you don blow, e just mean say, you dey make money."" E come reveal say im business na say sometimes e go get im own shoes to sell, oda times na oda importers dey give am and e go come give dem di money. ""But 30 million naira, you know how many containers dat one fit bring come? Di money no go change my life but e don change my destiny."" On top relationship mata for im life, im tok about im relationship both inside and outside di house even as e reveal say e don tay since im get babe. For im ship with Queen, e say na friendship dem get, e say, ""Queen na my padi for life, she bin make my waka inside di house to dey very easy. So e affect me wella wen she comot"". Anoda relationship wey make pipo to tok for house na im own with Pere, e recall say, ""na because we be two alpa males and one need to calm down for di oda one, but now we don dey alright."" For di mata of di pesin wey claim say she carri belle for am, Whitemoney shout say make she getat! E reveal, ""I neva dey any relationship since 2015 and wen I dey inside house, pesin come carri belle for me outside di house Tah! I no get dat kain omnipotent penis jare!"" E give advise to pipo wey wan enta di house as winner say di koko na to study wella for anytin you wan achieve. For im journey of how e dey study, e say, ""I don dey watch di show since di time wey Uti win for Big Brother Africa, and I don audition four times, I don study di show well-well. ""One tin wey common for evribodi wey win na say dem win based on dia real self. Dem no dey sell di win give anybodi."" Na so e tok. You fit watch di full interview here." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58847487 +entertainment Dalton Gomez: Ariana Grande and Dalton Gomez engagement gist "US singer Ariana Grande don reveal say she dey engaged to her real estate agent boyfriend, Dalton Gomez. Di star posted several photos on her Instagram page, wey show pearl and diamond ring on her left hand. ""Forever n then some"", di caption tok. Grande, age 27, din don dey date Gomez wey also de im twenties, for just under a year. Di couple [Ariana Grande and Dalton Gomez] dey currently live for Grande Los Angeles home, wia dem dey obey California stay-at-home orders, reports tok. In late October, Grande release her sixth album, Positions, wey climb to di top of both di UK and US charts. Di titular lead single also give her number ones on both sides of di Atlantic. Di singer don previously dey engage to US comedian and actor Pete Davidson, but them called off dia high-profile relationship two years ago." https://www.bbc.com/pidgin/world-55391908 +politics Nine steps to impeach a Nigerian President - Simple guide Opposition members of Senate don give ultimatum to President Muhammadu Buhari to fix security threat across Nigeria within weeks or face impeachment. On Wednesday, di floor of di senate inside di parliament bin see drama afta di senators insist to pass motion to mandate Buhari to improve di situation. Dis one make opposition senators for different party lines, vex waka comot from sitting. Di senators bin dey shout  say “President Muhammadu Buhari must go”. Dem address press, issue six weeks deadline to di president to begin im impeachment. But how di process dey actually work? BBC Pidgin consult Nigeria constitution and a constitutional lawyer to explain wetin e take - and why e fit be political risky. Constitutional lawyer Kennedy Osunwa na im tok about wetin di process to impeach a Nigeria president be. Oga Osunwa explain say no be now lawmakers suppose dey tok about impeachment. E say a lot of tins don happun for di kontri since president Muhammadu Buhari enter office and to tok about impeachment now dey some how as time no dey. Oga Osunwa further explain say according to di constitution, e dey possible to impeach president but two-third of di majority must agree say di president ghas go. Kennedy Osunwa say di process to impeach a president be long process. According to Section 143 of di 1999 Constitution of di Federal Republic of Nigeria as amended, here be di steps to impeach di President: Step 1 There must be notice of any allegation for writing wey allege gross misconduct on di part of di President. Dis notice must dey signed by not less dan one-third of di members of di National Assembly (both di Senate and House of Representatives) and e go dey presented to di Senate President. *Gross misconduct as di Constitution define am be ‘ grave violation or breach of di provisions of dis Constitution or  misconduct of dat kind nature as e amount for di opinion of di National Assembly to gross misconduct.’ Step 2 Di Senate President must within 7 days, serve di President and each member of di National Assembly wit one copy of di notice of allegation. Step 3 Di President get right of reply (e/she fit no reply), and any kind statement to reply to di allegation must dey served on each member of di National Assembly. Step 4 Within 14 days of di presentation of di notice to di Senate President, each chamber of di National Assembly ghas resolve by motion without any debate whether or not dem suppose investigate di allegation. Dis motion need pass by at least two-thirds majority of all members of each chamber of di National Assembly. Step 5 If di motion fails to reach di two-thirds majority, di process go immediately stop, and no further action go dey taken. However, if di two-thirds majority dey obtained and di motion dey passed, den di Senate President go within 7 days wey dem pass di motion, request di Chief Justice of Nigeria to appoint one Panel of seven persons wey for im opinion dey of unquestionable integrity to investigate di allegations. Di members of di Panel no fit be members of any public service, legislative house or political party. Step 6 Di President wey dem dey investigate im conduct under dis section go get right to defend imself in person and dey represented before di Panel by legal practitioners of im own choice. Step 7 One Panel go dey appointed wey go; (a) Get dat kind power and exercise in function according wit di kind procedure as fit dey prescribed by di National Assembly; and (b) Within three months of dia appointment report dia findings to each House of di National Assembly. Step 8 Where di Panel reports say di allegation never dey proven, there go be no further action. However, if di report be say di allegation against di President don dey proven, den di National Assembly go consider di report, and resolution for di adoption of di report go dey moved. Step 9 For di resolution to dey adopted, e must dey supported by not less dan two-thirds majority of all di members of each House. Once e dey adopted, di President go stand removed from office as from di date of di adoption of di report. President Muhammadu Buhari don again express serious concern ova di current security challenges wey some parts of di kontri dey face. Di president say e no go stop at nothing to change di tide, according to Buhari National Security Adviser to di President, Babagana Monguno, President Buhari tok dis one when e call emergency meeting of di National Security Council on Thursday for Abuja. All security chiefs and di Inspector General of Police bin dey expected to attend di meeting inside di presidential palace, Abuja. Dis meeting na di third in one month for di kontri political capital wey dey under safety threat. Early July, attackers dem identify as extremist militants hit di Kuje prison inside Abuja, free hundreds of prisoners. Dozens of Boko Haram convicts dey among di escapees. And since then di city dey face almost a daily security concern. On Wednesday some members of di National Assembly give President Muhammadu Buhari six weeks deadline to handle di mata. Senators of di opposition party say make Buhari fix di problem, if not dem go begin impeachment alias remove am from office. By: Daniel Semeniworima, Kareemot Salami https://www.bbc.com/pidgin/articles/cg65k9q5gxno +politics Duoye Diri: Bayelsa Election tribunal don dismiss three petitions against di state Govnor Jubilation dey di Bayelsa State Goment House as di state Govnorship Election Tribunal wey dey sidon for Nigeria capital, Abuja don affirm di election of oga Duoye Diri as Governor of di State and dismiss three petitions against am. Di judgment dey come few weeks afta di Supreme Court dismiss di appeal wey former aspirant of di Bayelsa governorship election under di People's Democratic Party (PDP), Timi Alaibe, bin file to challenge di victory of Senator Diri for di November 2019 election. Di three petitions wey di panel decide na di one wey Alliance for Democracy, United People's Congress, UPC and Liberation Movement parties bin file. For unanimous judgment wey Justice Owodunni deliver, di tribunal hold say di petition wey Owei Woniwei of Alliance for Democracy bring dey incompetent and lack merit as di petitioner fail to prove di allegations of forged declaration of age and National Youth Service Corps (NYSC) discharge certificate against di Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo. Di election tribunal also dismiss di petitions by Vijah Opuama of Liberation Movement and UPC candidate, Steve Ibiene say dem lack merit, come award cost of N800,000 against di UPC candidate, Steve Ibiene. https://www.bbc.com/pidgin/media-53792538 +politics Winner of Kogi governorship election: Thugs burn PDP woman leader alive - Dis na wetin we sabi "Pipo dey para ontop local media tori say political thugs burn di PDP woman leader alife for Kogi State, North Central Nigeria. Di latest report wey dey fly upandan say one Acheju Abuh, wey be di Women Leader of di kontri main opposition Peoples Democratic Party (PDP) Wada-Aro Campaign Council, Ochadamu Ward inside Ofu LGA na im jaguda pipo burn for inside her domot. Di tension still dey high for di state sake of dis mata, so dis na wetin BBC Pidgin don find out. Police confam give BBC on Tuesday say true true thugs burn down one house wey 60 year old woman bin dey inside for Kogi State, North Central Nigeria but dem no fit tok weda na di PDP woman leader or not. Meanwhile PDP National tok tok pesin Kola Ologbondiyan say dem neva receive report outside wetin don read for local media, but him as an individual fit confam di mata say e happun. How e happun? Police say on Monday 18th November 2019 at about 4:30pm, one Musa Etu of Ochadamu, Ofu LGA report for dia Station say at about 10:30am of di same date, misunderstanding bin happun between one 35 years old Awolu Zekeri wey be member of APC and one Gowon Simeon wey be member of PDP for Ochadamu. In di process Gowon Simeon stab Awolu Zekeri wit knife on top him lap, he come die as dem dey carri am go Hospital, Police add. Na so youths for di area begin para and mobilize pipo march go di house of one Simeon Abuh wey be di same domot of di uncle to di suspect, come set am on fire. Na as di fire dey bun na im e burn one 60 years old Salome Abuh. Three oda house na im also burn down in di process. Police say dem don carri di deadi bodi to di University Teaching Hospital Mortuary Anyigba for Autopsy. According to Faruk Adejoh-Audu wey be di tok-tok pesin for Wada/Aro Campaign Council, tok for statement say jaguda pipo wey dey chout GYB 4+4, begin shoot anyhow wen dem arrive madam Abuh house at about 2pm. Na dia dem gada and close everiwia wey pesin fit take escape, then pour petrol on top di building burn am down as oda villagers dey watch wit fear from wia dem dey hide. She try to escape through one window but dem prevent wit metal burglary proof and gun shots with bullets towards her direction, Adejoh-Audu tok. According to Wada/Aro Campaign Council, di thugs wait, still dey shoot and watch wit satisfaction while Mrs Abuh dey cry from inside di fire inferno until her voice die out. Meanwhile, Police Mobile Force and Police Special Forces don go tanda for di area to prevent any breakdown of law and order. Police tok tok pesin William Aya tell BBC Pidgin say di investigation still dey go on. Kogi State Govnor tok-tok pesin, Kingsley Fanwo say im dey sad ontop di ""mindless attacks by rival parties for Ochadamu"". Fanwo say anyone we break di law dem go punish am regardless of di party wey di pesin belong to." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50478152 +politics PDP National Chairman Uche Secondus: Profile of Prince Uche Secondus, PDP crisis so far "PDP National Chairman Uche Secondus don dey under fire to vacate im position inside di last few days. Dis na wetin BBC Pidgin dig up about di man dem dey call di 'Total Chair'. Secondus na di chairmo of Nigeria main opposition Peoples Democratic Party [PDP] wey dey face calls to regin. Crises don dey rock PDP in recent months wey don make many of di card members to port go di ruling All Progressive Congress [APC] party. Di crises reach climax on Saturday, August 7 afta di PDP caucus for House of Representatives release communiqué ask di politician to resign. As tins be so yawa for di party dey gas dey go. In response, di embattled National Chariman say in neva commit any offence wey go warrant am to resign. Dis na some of di tins you suppose sabi about dis Nigerian politician and businessman. Im na di current chairman of di PDP National Working Committee since 2017. Prince Uche Secondus join politics for 1978 during di Second Republic as Youth Leader of di National Party of Nigeria. In addition to being politician, Secondus na also businessman. Uche Secondus hold di position of Rivers State Publicity Secretary for di National Republican Convention party between 1993 to 1998. Between 2015 and 2016, im serve as acting chairman of di committee. Before dat time, im bin serve two terms as di second chairman of di Rivers State Peoples Democratic Party. And yes, na Rivers State born politician from Andoni Local Government Area. Governors under di Peoples Democratic Party Governors Forum meet with oda stakeholders on di issue of di National Chairman of di Party as some Party members dey call for im sack. Chairman of the PDP Governors Forum and Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal bin meet di PDP Governors Forum and dia discussions on di matter still dey continue. Di Forum bin don call for calm over di leadership crisis. Many stakeholders dey blame di National Chairman for poor management of di Party wey dem believe say cost di Party di defection of many members to di ruling All Progressives Congress APC sake of am. Pipo wey port from di party including Governors of Ebonyi, Cross River and Zamfara States and some members of di party for National Assembly and Board of Trustees BoT Seven members of di National Working Committee NWC don also resign dia positions as dem claim say di Chairman, Uche Secondus dey sideline dem in di administration of di Party. Sake of dis, di BoT members meet to intervene and at di end, dem decide to set up a committee wey go intervene for di crisis. Also, some members of di PDP caucus for House of Representatives for communique pass a vote of no confidence on am. Meanwhile, former Governor of Bayelsa State and Senator Bayelsa West Senatorial District, Sen. Henry Seriake Dickson don come out to say only di National Convention fit comot Secondus from office as Chairman of di Party. Sen. Dickson describe wetin dey happun as bad belle as three members of di National working Committe and three vice chairmen of di party no fit make up valid resolution di call for resignation. Seriake add say even a vote of no confidence wey a duly constituted NWC or oda organs of di Party still no fit remove di Chairman. ""Di Chairman dey voted for and na only di National Convention fit comot am unless im by imsef choose to resign."" Sen. Dickson say decamping of Governors and oda leaders no be Secondus fault as e don dey happen since 1999 and di PDP don also receive Governors and presiding officers of di National Assembly and Political leaders from oda parties before. ""Di whole issue na because say Secondus insist say Party decisions especially decisions about di direction of di Party for 2023 go be decision of all stakeholders…"" Na so Seriake Dickson tok But di National Chairman of di PDP still insist say im no go ever resign im position. Secondus tell tori pipo after im meet wit di PDP Governors Forum, wia dem ask am questions for about 40 minutes wen dem meet for Akwa Ibom State Governors Lodge for Abuja on Monday, 9 August, 2021. After di meeting, Secondus tell tori pipo say, ""I can confam say I will never resign"" and im no gree answer any oda question dem ask am. Di PDP Governors Forum dey continue with meetings wit oda stakeholders like di Board of Trustees and National Assembly Caucus on top di matter." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58164638 +sports AFCON 2019: Hosts Egypt beat Zimbabwe, commentator love for Salah Host Egypt start well for di Africa Cup of Nations afta dem Zimbabwe for di first game of di tournament for Cairo, as many praise di opening ceremony say no be here. Mahmoud Trezeguet score di only goal of di game when e curve one inside net just before half time. Liverpool forward Mo Salah almost score number two goal for second half but Zimbabwe keeper Edmore Sibanda say lai lai, no be today. Ovidy Karuru of Zimbabwe na im give dem dia best chance wit 30-yard shot im waya. Di opening ceremony na one wey some pipo for social media don compare to World Cup because e fine well well. Almost 75,000 fans pack inside di Cairo International Stadium wia dem see ogbonge ceremony with giant pyramids ontop field, correct dancers wey form di shape of pharaoh face and big fireworks show. Dis year tournament na di biggest Africa Cup of Nations ever wit 24 teams, and di first one dem go play during summer time for Europe. Salah ginger for first half but im shots just dey go wide but just as Zimbabwe begin wan show demsef Egypt humble dem with dia goal. Trezeguet play one-two to break enta di box before im place di ball for di for corner of Zimbabwe net. From then on Egypt just control di game till di end. Trust social media pipo, dem must tok dia own. Di commentator na di one of di pipo dem descend ontop, say im too gbadun Mo Salah because how im too hail am. But social media also praise di opening ceremony say e make sense. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48729383 +health Ghana Police go do mass burial for 200 dead bodies in Ghana Police Hospital "Ghana Police Service don announce to do mass burial for over 200 dead bodies wey no get relatives. Dis be what contain for statement wey dema issue on Monday take dey invite de general public. Police for Ghana want de public make dem come identify den claim dia relatives. ""We dey remind de public of de mass burial wey we tok for media from July 5, 2021 wey dey involve 200 unclaimed and unknown bodies make we take decongest our mortuary for de Ghana Police Hospital"". De statement continue tok say dis go be de second phase of de mass burial. ""We go appreciate if de public go see de pathology department from Monday August 23, 2021 to identify dia relatives for collection to avert de situation whereby such bodies go be added for mass burial"" de statement tok. DSP Yaw Nketia wey sign de statement take dey seek public cooperation on dis mata. De Ghana Police say dem dey wan decongest dema hospital mortuary so pipo wey no come claim dema relatives for burial go be part of mass burial by close of work dis week." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58314453 +health Covid-19 in Africa: Why some countries begin see rise for new cases "Increase don dey for Covid-19 infections in Africa over di past few weeks, according to di latest information. Di number of daily new cases don dey rise after di drop we see for mid-July, according to di Africa Centres for Disease Control and Prevention and di World Health Organization. During week ending of 1 November, new cases rise by 3% for WHO Africa region - we no include Morocco, Tunisia, Libya, Egypt, Sudan, Djibouti or Somalia. Ghana dey on di verge of second wave of Covid-19 as di country record 1,156 new cases. Active cases move from 397 cases to over one thousand in just two weeks. And WHO say Uganda record new highest daily increase for di virus in di past week, wit nearly half of di cases coming from di capital, Kampala. And di story no too different for Lagos, Nigeria commercial capital wia on Sunday new cases jump to 255 across two days, from former average of 90 per day. President Akufo-Addo address im kontri pipo for national television on Sunday wia e draw ear give dem say ""di virus no change…na our reduction in how we dey follow preventive protocols dey cause di increase."" ""We dey let our guard down. ""We no go fit to throw caution to wind at dis critical moment, den destroy di gains wey goment, health officials, heroic frontline health workers, and members of di security agencies dey do give us."" One WHO oga Matshidiso Moeti tok dis about Kenya, wia dem sef don see new case increase: ""Di most important [tin] na to contain [di rise] and not make di situation get out of control."". Dr Moeti also feel say pipo for Kenya fit dey tire of measures like to dey wear mask, social distancing and hand hygiene. Kenya mata resemble South Africa own wia dia health minister also say ""pandemic fatigue"" dey affect di population."" Meanwhile, sabi pipo for South Africa say ""superspreader"" events wey bring many pipo togeda, na im dem see as di cause of di rise in di kontri cases. E be like di main reason di continent dey see more recorded cases na sake of prevention measures wey pipo no dey follow like before. Also e dey important to torchlight say no data don show say international travel - wey don recently open for many kontries - don contribute to di increase. For many months South Africa hold di record for di highest number or cases for Africa and even today e never change. Di president for im weekly address president Cyril Ramaphosa say as di festive season dey come, make kontri pipo ""no become di architects of our own undoing"". South Africa goment ease lockdown measures for August. Still good news dey as di reported death rate per capita for Africa dey low compared with oda parts of di world, even though health infrastructure for many African kontris no dey bam. Di WHO say dis na because di continent get young population- more than 60% dey under di age of 25." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54872046 +politics Osun state election 2022: 'Give us one or two years and you go see wats up' - Davido "Award winning musician David Adeleke wey pipo alias Davido say e dey very happy wit di victory of im uncle, di Peoples Democratic Party, PDP candidate for di Osun state govnorship election of 2022, Senator Ademola Adeleke. Davido na key figure for Senator Adeleke campaign both for 2018 wen e first contest for di seat and 2022. Reacting to im uncle victory, Davido tell BBC Pidgin say, ""Family na everytin to me, apart from dat, we be di best pipo for di job, give us one or two years and you go see wats up."" E tok for im hometown of Ede, for Osun state, South West Nigeria. Dis no be di first time wey Senator Adeleke contest for di top job of Osun state, e contest for 2018, but afta election result wey dey too close to call and Inec call inconclusive, dem do re-run and e lose to di current govnor, Gboyega Oyetola. Di Independent National Electoral Commission declare di candidate of di All Progressives Congress, Gboyega Oyetola, di winner of di 2018 Osun governorship election. Dem return Oyetola as govnor-elect at di end of di supplementary election dem hold in seven polling units across four local goments. Di APC candidate wIn six ofdi seven units. At di end of di tally of votes, APC candidate score a total of 255,505 votes while PDP candidate score a total of 255,023 votes. Although Mr Adeleke bin lead im APC rival with 353 votes at di end of di first round of ballots, di table turn di oda way afta di supplementary votes wit di APC candidate overtaking and beating di PDP candidate with a total margin of 482 votes. Senator Ademola Adeleke na di uncle of Davido - Davido papa na di senator broda. See oda tins to know about am." https://www.bbc.com/pidgin/tori-62199487 +sports Fifa World Cup 2022 quarter-final, semi-final fixtures 32 teams, but only one fit win di trophy. Dat go be di hope of di 32 kontris wey go take part for di 2022 Fifa World Cup for Qatar. Na here you go find fixtures and results of all di matches from di group stage to di Final including di group table. https://www.bbc.com/pidgin/sport-63642818 +entertainment Police arrest Burna Boy security escorts wey allegedly shoot man for Lagos club plus everything we know "Nigeria Police say dem don arrest di officers wey allegedly dey involved in one shooting for Lagos club on Wednesday. Tori comot on Saturday say some police officers wey dey attached to one popular Nigerian musician Burna Boy allegedly shoot one man for a club for Victoria Island of di state. Force spokesman Olumuyiwa Adejobi say di Inspector General of Police don order di commissioner of police for Lagos to investigate di mata. For one Twitter post, one man wit handle @Theflowolf on Wednesday explain say di wahala start after one misunderstanding between im friends wey e carry go enjoy for club and ""Burna Boy pipo"". E tok say im friend sustain gun wound for leg and and another for im head. E explain further say dem later rush im friends to di Naval Medic Centre wia two soldiers donate blood to dem. ""Di doctor say di iPhone for im pocket wey di bullet enta na im make di shooting less fatal, di iPhone save im life"" e tok. For one Twitter post, police tok tok pesin say ""We don begin investigate di mata. We don identify and arrest di policemen. Dem don chop detainment almost immediately after di incident. ""Di IGP don order di CP of Lagos, CP Abiodun Alabi to conclude im investigation and forward report for necessary action"". Adejobi say dem neva see ""di artist"" (Burna Boy), be dem go question am wen dem get am. ""As usual we assure una of thorough investigation and decent judgment. We neva see di artist, but we go question am whenever we see am. Justice go dey serve for dis mata. We assure you."" BBC Pidgin don reach out to Ms Bose Ogulu wey be Burna manager for reaction. Dey born Damini Ogulu AKA Burna Boy wey be Nigerian singer-songwriter, record label executive, Burna Boy on di 2nd of July, 1991 for Port Harcourt city, Nigeria. E be di only son and eldest of three children to Bosede and Samuel Ogulu.Y oung Burna attend Montessori International primary school for Port Harcourt (1993-2002) and Corona Secondary School, Lagos (2002-2008). Burna search for knowledge take am outside Nigeria go United Kingdom to study Media Technology for University of Sussex (2008–2009) and Oxford Brookes University (2009–2010) to study Media Communications and Culture. Afta which e do one-year internship with Rhythm 93.7 FM Port Harcourt before e officially launch im professional music career wen e dem sign on to Aristocrat records - wey come make am permanent relocate to Lagos. Di singer wey win di Best Global Music Album category for di 63rd Grammy Awards afta dem nominate am two time back to back, na one of di most successful African singer for world." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp9n2vwlepxo +health Coronavirus - Virus: COVID-19 Infection di daso high as Cameroon confirm total of 13 positive cases Cameroon don confirm new cases of Covid-19 for total 13 cases for country as de number di so-so high. Yesterday Cameroon take some 13 strong measures for reduce spread-close border, schools, stop visas, gadaring for more dan 50 pipo and plenti odas. But, some kontri pipo say goment too late, as deh for act fast wen de first case start. Since weh Coronavirus enta Cameroon for March 6, till today na 13 case for Coronavirus dey Cameroon, but de first two don well, goment tok. Just now, de new cases weh deh get de disease dey for different parts of Cameroon, two for Bafoussam, one for Garoua. Goment say plenti of de cases di take treatment for Yaoundé and deh bring two from Bafoussam today. Yesterday goment order some passengers weh deh enta kontri for go sleep for some hotels for 14 days make deh check dem before deh go back home. If deh no get sign for de disease den deh go turn back for house. For Douala deh keep 261 pipo for hotels, and some dey for Yaounde. Some of dem di complain say de hotels dem no clean and some hotels no gree de passengers as deh no bi inform dem before. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51907641 +entertainment Baba Ijesha: Nollywood actor and comedian Princess bin dey date - Witness tok "Popular Nollywood actor wey dey face accuse of child defilement, Olanrewaju Omiyinka wey many pipo sabi as Baba Ijesha show face for court again for trial on Friday, 1 April. Di actor dey face six count charge of child defilement wey include allegations of indecent treatment of a child, sexual assault, attempted sexual assault by penetration and sexual assault by penetration. Police arrest di actor for April 2021 ontop allegation say in sexually assault one 14 years old girl. Dis na afta im colleague, Princess comot for one instagram to accuse di actor say im alleged rape di girl wen im visit im house. She bin also release CCTV video wey implicate di actor. For di trial wey kontinu for one High court for Ikeja on Friday, di actor bring one of im witness to testify to di case. Di witness, Kayode Ogunbanjo, wey pipo sabi as Pastor Jerosi, na di fourth witness wey di suspect don bring come court since di case start to tok wetin im sabi for di mata. Oga Kayode tell court say im be Baba Ijesha colleague and im sabi about di relationship wey dey between di suspect and di accuser, Princess. E say true-true Baba Ijesha dn Princess dey date, “Princess mama don tok am for my presence say make Baba Ijesha take care of her daughter.” Jerosi, wey tell court say e don reach 16 years im don dey work wit Ijesha, tok say di actors and comedian bin date . E add am say Princess dey invite Ijesha to one of her comedy programmes wey she bin dey do. ""Na five of us dey host di programme, one time for di show, Princess call on phone say she wan join di programme. Wen we reach di house, Baba Ijesha prostrate for Princess mama and di woman tok say make im dey take care of im daughter well-well.” Na dat time Baba Ijesha tell me say im dey date Princess but di relationship don pass wia e suppose reach. Wen di prosecutor lawyer, Yusuf Sule examine di witness, Jerosi say im no sabi anything about di sexual assault mata wey happun for Princess house on di 19 April 2021. Di comedian say how she take know say something dey wrong na wen di girl attitude begin change and she begin perform poorly for school. ""Di mata disturb me and I do evritin to make sure say she begin dey do well for school again."" She later inform di girl family say make dem dey pray for her as e fit be spiritual attack but she know deep down for her heart say something dey wrong. Princess say di girl later open up and accuse actor Baba Ijesha of inappropriate sexual behaviour. Na im she come dey reason plan how to catch am red-handed. Di comedian say she call Baba Ijesha say she wan shoot feem make e come her house. Before dat she don call CCTV company wey fix camera for di house. She tell everybody to comot except for di girl. Wen di actor come, she tell am make e relax say she wan quick-quick reach somewhere, meanwhile dem dey watch am from di camera. ''In two seconds wen I comot di house, he check everywhere for my house to make sure say nobody dey and di children dey sleep. He check di whole house for cameras, then e start. I no fit begin say di things e do. My body dey shake because we dey monitor from di phone. E reach one time, di girl stand say she wan go kitchen and no camera for dia, na wen pipo come enta be dat and we call di police,"" she tok. Dis alleged rape case raise dust for society as pipo begin protest in support and against di actor. Some say im dey innocent until proven guilty, odas say im suppose stay for detention to face di music of im alleged offense. Baba Ijesha dey face criminal charges wey include sexual assault, sexual assault by penetration, attempted rape and indecent treatment to pikin. Di actor spend some months for detention before court grant am bail for di month of June, 2021." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60966366 +sports Cristiano Ronaldo: Why statue of Portugal player dey divide opinion for India "One brass statue of Portuguese football star Cristiano Ronaldo wey dem newly unveil dey divide opinion for India. Di statue dey for western Goa state, wia football dey very popular, officials bin hope say e go inspire young people. But Portuguese also colonise Goa, and dis na 60 years since dem get dia freedom from Portugal. Critics say dem for honour local football players, especially since many past and present members of India national team come from Goa. ""Very disappointed to hear of di statue of Ronaldo wey dem raise. Learn to dey proud of our own stars like Samir Naik and Bruno Coutinho,"" one Goa pesin tell IANS news agency. During the statue inauguration, some pipo wave black flags in protest, di Times of India newspaper report. Portugal football team dey popular for Goa, and due to im colonial history, many Goa pipo dey live for Portugal or get family dia. But some pipo for di Indian state feel say na insult to install di statue wen Goa dey celebrate 60th anniversary of finally winning freedom from Portuguese rule, 14 years afta di rest of India get independence from British rule. ""To erect statue of Portuguese footballer dis year na abomination. We condemn dis,"" IANS quote right-wing activist Guru Shirodkar. ""E get many freedom fighters for Goa wey dem don insult,"" im add. Michael Lobo, one local lawmaker for di ruling Bharatiya Janata Party (BJP), tweet photo of imsef wit di statue, say dem don install am ""at di request of our youth"" to inspire dem ""to take football to greater heights"". Although cricket remain India most popular sport, football - especially di English Premier League - na favourite for some parts of di kontri - Kerala for south, Goa for west, West Bengal for east and all of di eight north east states. Cristiano Ronaldo, wey dey currently play for Manchester United, na darling of many fans and dem regard am as one of di best players in history of di game. Di 36-year-old forward neva comment publicly on di statue. Dis no be di first time wey im statue dey raise eyebrows - for 2017 dem mock one breast of Ronaldo and eventually dem replace am for Madeira airport for Portugal." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59822182 +politics Appeal court confirm Douye Diri election as Governor of Bayelsa state Di Court of Appeal for Abuja don set aside one ruling of di Bayelsa State Governorship election petition tribunal wey nullify di election of Douye Diri as di validly elected governor of Bayelsa State. For majority judgement wey dem deliver for Abuja on Friday 2 October, 2020, di court hold say di petition by di Advanced Nigeria Democratic Party (ANDP) dey statute-barred, and di tribunal no get jurisdiction to entertain di matter. Di court also say di tribunal no be di proper place to entertain di petition as e dey wrong to say di candidates of ANDP bin dey validly nominated. Di Bayelsa State Gubernatorial Petition Tribunal for split judgement of two to one on 17 August, 2020 bin don nullify di election of Governor Douye Diri based on a petition by ANDP wey argue say dem bin dey unlawfully excluded from participating in di election. Di five-man panel of di Court of Appeal wey Justice Adezila Mshelia lead set aside di tribunal verdict come uphold di appeal INEC and di Peoples Democratic Party PDP file against di majority judgment of di Bayelsa state governorship election tribunal and confam Governor Diri election. Di Governor of Bayelsa State, Sen. Douye Diri say di decision of di Court of Appeal wey uphold im election na di true position of di law.Im acknowledge di five judges of di Court of Appeal as di five wise men wey uphold di law and show say di common man fit go di judiciary get justice and thank dem for doing justice. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54390720 +politics Godwin Obaseki tori for Edo State news no dey new to Nigerian Govnors primary election - See list of those wey don fall out wit dia 'Godfathers' "Obaseki, Ambode, oda Nigerian govnors wey don fall out wit dia 'Godfathers' In times like dis, words like 'life na dynamic', 'dis no dey personal' and 'na for di good of di party' come to mind if you dey follow politics matter inside Nigeria. Time and time again, sitting govnors don fail to gain support of dia parties to contest primary election in order to contest re-election as e just happen for Edo State, south south Nigeria. But dis trend don make pipo wonder wetin go make political parties decide to no longer throw dia weight behind candidate wey don represent di party before for election or one wey di pipo wey dey vote fit see as sure bet for certain positions. Some don describe such decisions as influence wey 'come from above' or wetin pipo dey call Godfather for Nigeria politics. Dis Godfathers dey like decision markers wey fit pick and choose who dem want be di next representative of a party ahead of forthcoming elections and most times dem dey get dia wish. Currently, na dis same pattern dey play out for Edo State according to di tok tok pesin of Edo State govnor, Godwin Obaseki wey say ""Comrade Adams Oshiomhole don declare say im be di Supreme Court and pesin wey go determine di fate and future"" of di next candidate wey go contest govnorship primary for di state ruling APC party. Oga Crusoe Osagie tok dey come afta di All Progressive Party for di state disqualify govnor Obaseki from to participate in di party primary, but dis no go be di first time wey such drama go happun for Nigeria. For 2018, tori comot say govnor of Lagos State at di time, Akinwunmi Ambode bin dey kwanta wit leader of di All Progressive Congress, Bola Tinubu. Even though say Ambode deny di tori say e no dey fight di APC leader, e surprise many wen di party chieftain throw e weight behind di den chairman of di Lagos State Property Development Commission (LSDPC), Babjide Sanwo-olu istead of di serving govnor Ambode. Ambode later lose im bid for second term afta 970,851 pipo vote for Sanwo-Olu during di party primaries on October 2, 2018. Im score only 72,901 votes. Di once rosy father and son relationship of 2015 sawa few years after Senator Godswill Akpabio comot from di ruling People's Democratic Party go join di APC. Seen as many as di political godfather of Akwa Ibom State, Sen. Akpabio anoint di former Director General of di Niger Delta Development Commission, Nsima Ekere to be di next govnor of Akwa Ibom state. Akpabio even declare few months before di state elections say politics for di state ""go be like di invasion of Hitler"", comments wey no go down well wit Udom Emmanuel. Despite di challenge of Nsima Ekere, Govnor Udom no only win re-election di drama come turn out in di way wey be say even Sen. Akpabio lose e re-election for second term as senator wey go represent di North West Senatorial District of Akwa Ibom state. For years di PDP reign Supreme for Nigeria oil rich Rivers State until one man decide to test di foundations of di party for 2015 wen e decamp go di APC. Rotimi Amaechi govern Rivers State for eight years under di umbrella of di PDP, and during dat period e rise to di level of pesin wey sabi di political game even though technically na only one election im contest and win to be govnor of di Nigerian southern state. Im defection to di APC bin look like for di first time since democracy rule for Nigeria anoda party oda dan di PDP go rule Rivers State. Already, him and e former Chief of Staff, Nyesom Wike relationship bin no sweet as e bin be before wen e be govnor, Wike imsef bin get di support of di den president of Nigeria Goodluck Jonathan. Amaechi side wit Dakuku Peterside under di umbrella of di APC to rival Wike, but in di end Wike win di 2015 govnorship election." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53033110 +entertainment Victony: Davido, Laycon, odas pray for Victony as di Nigerian rapper wan undergo major surgery afta car crash - See di latest Nigerian celebrities don start GoFundMe to raise money for rapper Victony wey involve in one major accident on Monday. One Mr Dafe, wey be talent manager, break di news on Tuesday for one series of tweets l, say di incident happun early hours of Monday. Dafe reveal say one pesin - im call Doyin - die for accident and 3 oda pipo seriously wunjure. “Victony was unfortunately severely injured he dey set to undergo a surgery today.” he tok for di tweet. Wit a target of $50,000, friends of Victony don create a GoFundMe account to support im medical bills. “We dey start dis on behalf of Victony wit im family authority. All funds donated to dis course go dey directed into his medical bills, post surgery recovery and therapy. “ dem write as di description under di funding account. As at the early hours of Wednesday 28 April, dem don raise $3550. Celebrities don also react to Victony accident as dem ask for support and also pray for dia colleague. See some of dia reactions: Victony na Nigerian rapper. Im be one of di newest artist for di music industry. Victony real name na Anthony Victor. He dey signed to MainlandBlockParty, one record label owned by Tobi Mohammed. Di musician, also known by fans as di Outlaw King, bin release in debut EP last year, titled ‘Saturn’. He feature popular artiste like Falz di bad guy for di EP. Two days to di accident, im bin just release new music video ‘Euphoria’ wey im collabo sing wit Hoodini, anoda fast rising Nigerian act. . https://www.bbc.com/pidgin/tori-56911932 +health Coronavirus lockdown: Seven tins wey dey happun during 'total lockdown' for Covid19 Kontris all ova di world dey do everitin possible to stop di spread of coronavirus as di new virus don kill ova 13,000 pipo. Since di new COVID-19 virus start for China for December 2019, e don spread to at least 177 kontris, e don affect ova 300,000 pipo, and about 93,000 pipo don recover from am. As di disease dey spread many kontris all ova di world dey announce 'Total Lockdown' for weeks make dem for fit contain di spread of di virus. Rwanda na di first African kontri to impose total lockdown for two weeks. Lockdown na wen authorities order dia citizens make dem no comot for dia house anyhow - Make we show you how e dey work. Any place where dis seven dis happun, make you sabi say nadat place don enta 'total lockdown' Di first tin kontris dey do na to dia close border,(air space, sea ports and land borders). E mean say dem no go allow pipo from oda kontris , especially kontris wey don record plenti cases of Coronavirus to enta dia kontri. but dem go allow goods and cargos to enta di kontri. Most kontris dey allow dia citizens to travel come but dem go first quarantine dem for atleast 14 days before dem go allow dem go dia house. To travel from one city to another no dey happun wen kontri declare total lockdown except na for medical reason or oda reasons wey dey important. Waka-waka no go dey for pipo to dey go upandan unnecesarily. Goment no go allow pipo to dey visit each oda, you no go comot from your house except you wan go buy food or you wan use di bank or you need medical attention. Goment dey advise make public and private workers work from dia house apart from pipo wey dey provide essential services like pipo wey dey sell food, supermarket owners, health care personnel and pipo wey dey work for financial institutions. Wen total lockdown dey, dem no dey allow pipo go school make dem for no dey exposed to di virus. Goment go close schools and advise say make schools send dia curriculum to students through di internet. Party time don dey ova!, No weddings, No burial, no birthday party and any oda kain event wey go bring pipo togeda. Religious buildings go close, clubs no go open if total lockdown dey for any kontri. Di reason na to put full stop to how di disease dey spread from one pesin to anoda Goment dey allow pipo to transport food and oda tins wey pipo need to survive within di weeks wey di kontri dey on lockdown. If pipo go enta transport at dis time, dem dey advise say make dem dey atleast 2cm away from the pesin wey near dem make body no touch bodi and make pipo no shake hands or hug each oda. Experts believe say di more aggressive measures wey kontri go put in place go helep slow di rate di virus dey spread over time. Professor Ooi Eng Eong, one sabi pesin for emerging infectious diseases at di National University of Singapore. tell BBC say di new infection begin dey fall within two to three weeks of lockdown for Hubei province for China wia di virus bin start from as dia goment impose di biggest quarantine for human history. If di seven tin we list hia dey happun for your area, know say na total lock down you dey so. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51996682 +entertainment "The unidentical duo: Olianna & Olivia AKA ""The Unidentical Duo"" say dem like to dey denge pose" "Olianna & Olivia AKA ""the Unidentical Duo"" na Instagram celebs for Nigeria and Adetutu Daramola, dia mama don tok how her pikin dem modelling career take start. ""Dem start to model wen dem dey four months old"" na wetin madam Daramola tell BBC Pidgin. Madam Daramola get four pikin but na her five year old twins [Olivia and Oliana] wey dey totori pipo for social media wit dia swagger. Di girls get dia own official Instagram account wey get wit ova 150, 000 followers wia dem dey post videos about dia fashion work. Madam Daramola say even though dem dey do modelling work dem no dey take school play. She share some tips for parents wey get young children like her own to help groom dia talents." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55299032 +sports Lukaku: Chelsea re-sign Belgium striker from Inter Milan for club record £97.5m "Chelsea don re-sign striker Romelu Lukaku from Inter Milan for £97.5m. Di 28-year-old Belgian return to Stamford Bridge on five-year deal, afta im leave di Blues to join Everton for £28m for 2014. Di fee dey just short of di British transfer record of £100m wey Manchester City pay Jack Grealish. ""I come here as pikin wey bin get a lot to learn, now I dey come back wit a lot of experience and more mature,"" Lukaku tok. ""I don support Chelsea as pikin and now to come back and try to help dem win more titles na amazing feeling."" Clubs don spend more money on Lukaku than any other player for history as all di clubs wey im don play for don pay combined figure of about £290m in transfer fees for am. Two of di top five fees paid for a player for British football history don be for Lukaku head. Belgium all-time top goalscorer na di most expensive player ever sold by any Serie A club, afta e become di third most expensive buy for Italy history wen e join Inter for 2019. European champions Chelsea finish fourth for Premier League last season, dem score 58 goals - di eighth-highest total for di division. German striker Timo Werner, wey dem sign for reported fee of about £48m for June 2020, contribute just six goals in 35 league appearances. Chelsea director Marina Granovskaia tok say, in Lukaku, dem don sign ""quite simply one of di world's best strikers and goalscorers"". ""We dey absolutely happy to bring am back to di club e love, and dey excited to add e talent to our Champions League-winning squad,"" she tok. Lukaku, wey help Inter to win di Italian Serie A title last season, say di chance to return ""come at di right time"". ""'Di way di club dey go fit my ambitions perfectly at 28 and just coming off winning Serie A,"" e add. ""Hopefully we go get a lot of sucess together."" Im arrival for Stamford Bridge could fit lead to di exit of other strikers as Roma and Arsenal dey interested in 23-year-old England international Tammy Abraham and out-of-favour Michy Batshuayi dey linked wit move to Turkey." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58194522 +sports Olympic games Tokyo 2020: Hugues Fabrice, Zango, Abel Kipsang and Ghana men 4x100m relay team make Africa proud for Olympics "Africans no slack at all for di Tokyo Olympics as athletes from di continent continue to secure dia place for semi-final, finals and even win medals. Athletes from Burkina Faso, Kenya, Ghana and oda kontris for Africa make dia kontri proud as dem break history. Hugues Fabrice Zango win Burkina Faso first ever Olympic medal as e claim bronze for di men triple jump on day 13 of di Tokyo Olympics. Hugues Fabrice Zango admit say e bin get mixed feelings as e win bronze for di men triple jump. Di 28-year-old leap of 17.47 metres dey 35cm short of im African outdoor record, wey e set earlier dis year, but e dey enough to claim third place just ahead of two-time Olympic silver-medallist Will Claye of USA. ""Na pleasure for me to be di first medallist for my kontri for di Olympics. Na good thing for us,"" Zango, di indoor world record holder tok afta di final. ""I dey little sad because I no dey able to produce my best performance and dis na wetin make di medal no dey good as I bin want. ""I tink say dis go open di way so for di next Olympics we go get more medals."" Kenya Abel Kipsang set new Olympic record as e win di second semi-final to qualify for Saturday final of di men 1500m. Di 24-year-old time of 3 minutes 31.56 seconds surpass di mark wey im compatriot Noah Ngeny bin set wen e win gold for Sydney Games for 2000. For di earlier semi-final Kenya world champion Timothy Cheruiyot finish third and qualify automatically for di final. For di heats for di men 4x100m relay Ghana finish ahead of USA and set new national record of 38.08s to qualify for Friday final as one of di fastest losers. Di Ghanaian quartet dey made up of Sean Safo-Antwi, Benjamin Azamati-Kwaku, Emmanuel Kwaku and Joseph Paul Amoah. However disappointment dey for South Africa (Clarence Munyai, Shaun Maswanganyi, Chedrick van Wyk and Akani Simbine) as dem fail to pass di baton on di very first exchange. South Africa Wayne Snyman na 20th of di 52 finishers for di men 20km walk as e end up 3 minutes 28 seconds behind Italian winner Massimo Stano. Egypt men go need to settle for bronze-medal play-off match on Saturday afta dem lose dia semi-final 27-23 to Rio silver medallists, France. Di French na di successful handball nation of all time afta dem don win world championships six times and also two-time Olympic champions. Di Egyptians, wey be di first African team to reach Olympic semi-final, go face Spain for di bronze medal afta dem lost 27-23 to reigning world and Olympic champions Denmark for di oda semi-final." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58104096 +politics Willie Obiano arrested: Rochas Okorocha, James Ibori, Bukola Sraki - Nigerian govnors wey EFCC don arrest at di end of dia immunity "Former Anambra state govnor Willie Obiano na di latest among di former Nigerian govnors wey di kontri corruption police don arrest afta dem loss immunity. In recent years di Economic and Financial Crimes Commission don arrest at least thirty (30) Nigerian govnors for different kains of charges at different times. Most times dia offences dey include abuse of state contracts and diversion of goment moni for dia personal use. According to Nigeria 1999 Constitution as amended, state govnor dey enjoy plenty power and dem dey control budgets wey big pass some African kontris own. To protect di dignity of di office, part of di power wey state govnors for di kontri dey enjoy na power of immunity. Section 308 of di 1999 Constitution as amended say: ""Notwithstanding anytin to di contrary for dis constitution, but subject to subsection (2) of this section, no civil or criminal proceedings go dey instituted or continued against pesin wey dis section apply during im period for office. ""Pesin wey dis section apply no go fit chop arrest or put for prison during di period either to pursue process of any court or odawise; and no process of any court wey require or force dis pesin wey dis section apply, fit dey aplied for or issued."" Diafore, EFCC only fit arrest any govnor only aft aim term for office don finish and im immunity expire. Since di beginning of di fourth republic for 1999 reach now, EFCC don arrest 30 govnors, Willie Obiano make am di number 31. EFCC arrest di former Govnor Obiano on Thursday di 17 of March 2022. Im arrest come di same day e hand over power give Govnor Charles Soludo. Di corruption police say im im bin don dey dia watchlist since but dem bin no fit gbab am becos immunity bin cover am. Ibori wey be di former govnor of Delta State for eight years (1999 to 2007) chop 13 years prison sentence for fraud of nearly $77m. Di former govnor bin admit to 10 count charge of conspiracy to defraud and money laundering to South Crown Court for UK. Ibori dodge capture for Nigeria but dem arrest am for Dubai for 2010, extradite or send am go UK. Okorocha, wey be Imo state govnor between 2011 and 2019, chop EFCC arrest on 13 April, 2021 for im Unity House office for Garki, Abuja. Dem accuse am of embezzlement and misappropriation of fund, allegation wey e don deny. Okorocha EFCC arrest happun weeks afta Imo State Police arrest am for February 2021 on top accuse say e reopen one estate wey dem link to im wife. Former President of Nigeria Senate and former govnor of Kwara state, Olubukola Abubakar Saraki no escape di hand of di corruption police. As senate president Saraki face corruption accuse and false declaration of asset. Supreme Court acquit am for June 2018. But EFCC for July 2021 detain Saraki on top new accuse of steling and laundering of public funds using friends and fake companies wey don dey give returns for many years. Former Govnor of Abia State, Orji Uzor Kalu collect 12 years prison sentence for fraud. Di mata relate to di time wey oga Kalu bin govnor for Abia State although im later comot office to become Senator. Court find Kalu, and two odas guilty of N7.65billion ($19.6m) fraud. EFCC accuse Kalu and di two oda pipo say dem kolobi money wey bin belong to di south-eastern state between 1999 and 2007. For 2018 EFCC put former Ekiti state govnor Ayodele Fayose dia watch list so dat e no go escape aft aim handover power to new governor on October 16, 2018. Twenty-four hours afta im leave office Fayose cari imsef submit for EFCC domot wit plenty drama as im carry plenty supporters follow body. Fayose mata still dey court on amended 11 count charge of moni laundering. Oda former govnors wey EFCC don arrest" https://www.bbc.com/pidgin/media-60777063 +sports Paralympics medals table Tokyo 2020 Di 2020 Paralympic Games for Japan go feature a record 4,400 Para athletes wey go compete for 540 events across 22 sports. Dis page, contain di medals table rankings, and go dey update automatically evri 10 minutes to show di number of gold, silver and bronze medals wey di national Paralympics committees of di kontris wey dey participate for di competition win. Dem go award di first medal on August 25th, 2021. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58306134 +business How South Africa president survive impeachment move over cash-in-sofa scandal "MPs for one special sitting of South Africa parliament on Tuesday vote to reject one move to begin impeachment proceedings against President Cyril Ramaphosa. Dem accuse di president of covering up di theft of one large sum of foreign currency from im farm in 2020, some of which bin dey hidden inside one sofa. Di debate before di vote bin focus on an independent report wey conclude say e fit don violate di constitution. Oga Ramaphosa, wey dey prepare for re-election as ANC leader, deny any wrongdoing. Di African National Congress bin tell im MPs to block possible impeachment - although a handful break ranks and join hand with opposition parties and vote to accept di report and let impeachment proceedings start. Now wey Oga Ramaphosa don survive di vote, belief dey say e dey likely to win re-election for im party conference, wey go start on Friday. E go den be in pole position to become di ANC presidential candidate for di next election in 2024. Di sitting to debate to di report, wey dey commission from one panel of legal experts by di speaker, open wit one discussion over whether dem should allow MPs to vote in secret - something wey di speaker bin reject. At di end of di debate, dem read out di names of individual MPs and each one announce dia vote. Some 214 lawmakers vote against setting up impeachment committee, while 148 vote in favour, dem register two abstention. Di 70-year-old leader don deny any wrongdoing calling di report, wey e don also challenge for di Constitutional Court, ""flawed"". Oga Ramaphosa become president for 2018 pledging to tackle corruption. Naim replace Jacob Zuma, whose time for office bin dey weighed down by many such allegations. Dis scandal show facein June, wen one former South African spy boss, Zuma-ally Arthur Fraser, file one complaint wit police accusingdi president of hiding theft of $4m (£3.25m) in cash from im Phala Phala game farm in 2020. Oga Ramaphosa admit say dem bin tiff some money, wey bin dey hidden in a sofa, but e say na $580,000 not $4m. Di president say di $580,000 bin come from di sale of buffalo, but di panel, wey dey headed by one former chief justice, say e get ""substantial doubt"" about whether a sale take place. South Africa get strict rules on holding foreign currency, wey say dat it gatz dey deposited with an authorised dealer such as bank with 30 days. E appears as though di president fit don break those rules, according to di panel report. Furthermore, if di money na from selling buffalo as e tok, dis money supposed dey declared, rather dan keep am in cash. For im submission to di Constitutional Court, Oga Ramaphosa want di kontri top judges to rule say di findings of di panel dey unlawful and set aside. Di president argue say di panel go beyond im scope wen dem dey look at whether e bin get a case to answer related to di robbery for di farm. E dey also ask di court make dem declare say any steps wey di parliament take on di back of di release of the report dey unlawful and invalid. Analysis by Nomsa Maseko, BBC News, Johannesburg Di dominance of di ANC for parliament don save Oga Ramaphosa future in politics. Im chances of being re-elected as ANC president for di party national conference now don get more boost. However, events for parliament show say once again deep divisionsdey for di governing party. Four Pro-Zuma supporters, wey include former African Union chairperson, Nkosazana Dlamini Zuma - one ogbonge party member - bin vote with opposition parties. Di opposition bin try, and fail, to push for secret ballot as dem sense say more members fit break ranks. But Tuesday win na only political, and not legally binding. Oga Ramaphosa go still need to get di Constitutional Court to weigh in on di mata, though some experts say di judges dey likely to side wit am afta parliament, wey commission di investigate, bin reject im own report. For now, on top of one huge sigh of relief, Oga Ramaphosa march on wit severe political bruises - im credibility and ability to govern go come into even sharper focus." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c9rl22gyln4o +health Coronavirus: Greater Accra lead Covid-19 infections for Ghana Greater Accra lead Covid-19 infections for Ghana as 1,852 cases out of total 2,169 dey de capital. Dis dey account for over 85 percent of cases for wey Ashanti den Eastern region dey follow. De virus spread catch twelve out of sixteen regions for, dis be regional breakdown of how Covid-19 spread for Ghana. So far Coronavirus patients wey recover for Ghana rise catch 229. Dis be after 17 new people recover after de last declaration by Ghana Health Service. One more person die which de take de death toll go 18, wey de total cases be 2,169. https://www.bbc.com/pidgin/world-52510586 +politics Bayelsa Governorship: Police arrest 8 pipo on top Destruction of houses for Yenagoa "Police don arrest 8 pipo on top palava wey happen for Yenagoa, di Bayelsa State capital afta jaguda pipo attack and destroy houses and offices as di new govnor take ova. Di jaguda boys scatter di house of di former Govnor Seriake Dickson, personal house for Opolo, di new Govnor Douye Diri house for Imgbi road, PDP state secretariat and Radio Bayelsa premises for Ekeki, Yenagoa. Na di katakata make di state Police Commissioner Uche Anozia, declare three days curfew to maintain law and order for di State. Meanwhile Radio Bayelsa dey off air since yesterday afta jaguda boys go destroy tins including cars for di station. Mrs Vivian Gabriel, Head of Admin, Radio Bayelsa, tell BBC Pidgin say around 11am, dem see jaguda boys with stones enter di premises begin destroy tins and Dem get to shut down. Doris Francis wey be Sport Analyst and commentator for di station, say as dem wan comot wit di Outside Broadcast van na im dem see jaguda boys wit stones rush inside di compound. ""We hear dem dey shout, who take di breaking news, which of you take di breaking news of wetin dey happen for di State as INEC give certificate of return to di new Governor. So we get to run comot through di swamp wey dey back enta NTA premises. Na so we take escape. Dem destroy my car and even I even get wound sef."" Na so she tok. Many offices and cars of workers for di radio station dey destroyed. Di decision of di Supreme Court to remove di APC candidates David lyon and Biobarakuma Degi-Eremienyo as govnor elect of di state cause kasala as supporters of di party begin to protest plus scata tins. Nigeria Independent national electoral commission (INEC) issue di people's Democratic Party Candidate, Douye Diri e certificate of return to be di new govnor of Bayelsa State. Dis na afta Inec say dem accept di Supreme court judgement wey declare Douye Diri as winner of Bayelsa state election. Di chairman of di commission, Professor Mahmood Yakubu say dem don receive di court judgement and wetin di court ask dem to do. On Thursday, Supreme Court for Abuja cancel Bayelsa State governor-elect David Lyon as winner of di 2019 election for di state. Di five-man panel of Nigeria highest court bin declare PDP candidate Douye Diri as winner of di state governorship election. Di court decision turn table for oga Lyon wey dem for swear into office on Friday, February 14, afta all di plenti preparation wey im don bin dey do for di inauguration." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51504452 +business Why Tiktok owner hand over pipo data to Chinese goment "Chinese internet giants including Alibaba, Tiktok-owner Byte Dance and Tencent don share details of dia algorithms wit China for di first time. Algorithms dey decide wetin users see and di order wey dem take see am - and dey critical to drive growth of social media platforms. Dem dey guarded by companies wella. For di US, Meta and Alphabet don successfully argue say dos tins be trade secrets despite calls for more disclosure. Di Cyberspace Administration of China (CAC) don publish one list wit di description of 30 algorithms. For statement, e say di algorithm list go dey updated so dem go fit stop data abuse. Among di algorithms wey dey di list be one wey e-commerce website Taobao, by Alibaba own. Di Mandarin document say Taobao algorithm ""dey recommend products or service to users through dia digital footprint and historical search data. ""ByteDance algorithm for Douyin, China version of TikTok, dey gauge user interests through wetin dem click, comment on, ""like"" or ""dislike"". Kendra Schaefer, head of tech policy research for Trivium China, say di data show for ""surface level"". ""E no look like say dem don submiit di algorithms themselves,"" she tell BBC. ""Each one of dis algorithms don get registration number, so di CAC fit focus enforcement efforts on one particular algorithm. Di question be, wetin be di next step to see if one algorithm dey up to code? ""However, Zhai Wei, one executive director for di Competition Law Research Center for di East China University of Political Science and Law, believe say di information dem provide get "" more detail dan wetin dem publish for sure"". ""Dat one involve some business secrets, wey no dey possible to dey released to di public,"" e tell Bloomberg. ByteDance no gree comment wen BBC ask am on Tuesday. Alibaba and listed technology firms Tencent, NetEase and Baidu no respond immediately to BBC request for comment. According to Suranjana Tewari, Asia Business Correspondent dis move dey ultimately about control. China get di largest base of internet users for di world, and be big market for e-commerce, gaming and smartphones. And so, technology companies wey dey operate there don expand sharpaly for recent years. Beijing dey seriously protect di technology behind dis companies, and no dey allow di export of am beyond dia shores. But dem dey worry about how dis platforms fit influence public opinion within China, and prefer to get more oversight over dia technology and data. Dem want redirect pipo attention to content wey di state think say dey ok for public consumption. Beijing don urge service providers to make sure say algorithm ""actively spread positive energy"", and no dey used to encourage over do, too much spending and expose to celebrity culture. International brands like Google and Facebook don dey under pressure to submit dis kind information sake of concerns about how dem dey use data and create content, but dem don argue until now, say algorithms be business secrets. Chinese regulators don dey tight hand for technology sector for nearly two years now. Di kontri adopt new rules for algorithms for March - wey allow users to pull out to contribute to recommendations. E also be required algorithms wit ""public opinion properties or social mobilisation capabilities"" to register wit di CAC. Ms Schaefer say e dey ""remarkable"" say di registrations dey for public. ""I no sabi say any oda kontri in di world where you fit go see list of all of di pieces of code wey dey essentially inform di decisions wey you make, di purchasing decisions wey you make, di content viewing decisions wey you make,"" she tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cglzply4d78o +entertainment BET Awards 2020: Burna Boy, Megan thee Stallion, Wizkid and all di oda winners of di Television channel award "Burna Boy, Nigerian Afrobeats singer and 'Odogwu' crooner don collect di award of Best International Act for di BET Awards 2020. Burna Boy beat music acts like Sho Madjozi from South Africa , Stormzy from UK alongside four other singers to win di award. Dis na di second time wey 'Oluwa Burna' go win di Best International Act category afta im win am for 2019. During e thank you message wey e do online, Burna Boy say: ""e go like use di opportunity to say...for Black Lives to matter, Africa mus matter."" For di BET Her Award category, Wizkid also dey part of di pipo wey win am for di Brown Skin Girl song wey Beyonce feature am. But no be all Nigerians wey dem nominate win dia category as fast rising act, Rema lose di Best New International Act category wey dem bin nominate am. Zimbabwe singer Sha Sha na im win di award for Best New International Act. Best International Act Burna Boy (Nigeria) WINNER Innoss'B (DRC) Sho Madjozi (South Africa) Dave (U.K.) Stormzy (U.K.) Ninho (France) S.Pri Noir (France) Viewer's Choice: Best New International Act Rema (Nigeria) SHA SHA (Zimbabwe) WINNER Celeste (U.K.) Young T & Bugsey (U.K.) Hatik (France) Stacy (France) Album of the Year ""Cuz I Love You,"" Lizzo ""Fever,"" Megan Thee Stallion ""Homecoming: The Live Album,"" Beyoncé ""I Used to Know Her,"" H.E.R. ""Kirk, ""DaBaby ""Please Excuse Me For Being Antisocial,"" Roddy Ricch WINNER Best Female R&B/Pop Artist Beyoncé H.E.R. Jhene Aiko Kehlani Lizzo WINNER Summer Walker Best Male R&B/Pop Artist Anderson .Paak Chris Brown WINNER Jacquees Khalid The Weeknd Usher Best Group Chloe x Halle City Girls EarthGang Griselda JACKBOYS Migos WINNER Best Collaboration Chris Brown Ft. Drake, ""No Guidance"" WINNER DJ Khaled ft. Nipsey Hussle & John Legend, ""Higher"" Future ft. Drake, ""Life Is Good"" H.E.R. ft. YG, ""Slide"" Megan Thee Stallion ft. Nicki Minaj & Ty Dolla $ign, ""Hot Girl Summer"" Wale ft. Jeremih, ""On Chill"" Best Male Hip Hop Artist DaBaby WINNER Drake Future Lil Baby Roddy Ricch Travis Scott Best Female Hip Hop Artist Cardi B Doja Cat Lizzo Megan Thee Stallion WINNER Nicki Minaj Saweetie Video of the Year Chris Brown Ft. Drake, ""No Guidance"" DaBaby, ""Bop"" DJ Khaled ft. Nipsey Hussle & John Legend, ""Higher"" WINNER Doja Cat, ""Say So"" Megan Thee Stallion ft. Nicki Minaj & Ty Dolla $ign, ""Hot Girl Summer"" Roddy Ricch, ""The Box"" Video Director of the Year Benny Boom Cole Bennett Dave Meyers Director X Eif Rivera Teyana ""Spike Tee"" Taylor WINNER Best New Artist DaniLeigh Lil Nas X Pop Smoke Roddy Ricch WINNER Summer Walker YBN Cordae Dr. Bobby Jones Best Gospel/Inspirational Fred Hammond, ""Alright"" John P. Kee ft. Zacardi Cortez, ""I Made It Out"" Kanye West, ""Follow God"" Kirk Franklin, ""Just for Me"" WINNER PJ Morton ft. Le'Andria Johnson & Mary Mary, ""All In His Pain"" The Clark Sisters, ""Victory"" Best Movie ""Bad Boys for Life"" ""Dolemite Is My Name"" ""Harriet"" ""Homecoming: A Film by Beyoncé"" ""Just Mercy"" ""Queen & Slim"" WINNER Best Actress Angela Bassett Cynthia Erivo Issa Rae WINNER Regina King Tracee Ellis Ross Zendaya Best Actor Billy Porter Eddie Murphy Forest Whitaker Jamie Foxx Michael B. Jordan WINNER Omari Hardwick Young Stars Award Alex Hibbert Asante Blackk Jahi Di'Allo Winston Marsai Martin WINNER Miles Brown Storm Reid Sportswoman of the Year Ajeé Wilson Claressa Shields Coco Gauff Naomi Osaka Serena Williams Simone Biles WINNER Sportsman of the Year Giannis Antetokounmpo Kawhi Leonard LeBron James WINNER Odell Beckham Jr. Patrick Mahomes II Stephen Curry BET HER Award Alicia Keys, ""Underdog"" Beyoncé ft. Blue Ivy, WizKid & Saint Jhn, ""Brown Skin Girl"" WINNER Ciara ft. Lupita Nyong'o, Ester Dean, City Girls & La La, ""Melanin"" Layton Greene, ""I Choose"" Lizzo ft. Missy Elliott, ""Tempo"" Rapsody ft. PJ Morgan, ""Afeni"" Viewer's Choice Award Chris Brown Ft. Drake, ""No Guidance"" DaBaby, ""Bop"" Future ft. Drake, ""Life Is Good"" Megan Thee Stallion ft. Nicki Minaj, ""Hot Girl Summer"" WINNER Roddy Ricch, ""The Box"" The Weeknd, ""Heartless""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-53216702 +health Covid-19 in Ghana: Concerned doctors for Ghana petition Akufo-Addo against mandatory Covid vaccination "A group of Ghanaians who dey call themselves, Concerned Ghanaian Doctors petition President Akufo-Addo to drop de decision to make Covid-19 vaccination mandatory give Ghanaians. According to de group of doctors, dis be necessary sake of say unanswered questions dey about de efficacy, necessity den safety of Covid vaccines. Dis call dey come on de back of govment decision to make vaccination compulsory for some group of Ghanaians and some public places starting dis January. Inside petition wey dem sign inside, de 11 doctors explain say some developed counties wey get high vaccination rates now dey give Covid booster. Despite dis, dem say dis countries dey struggle to get de virus under control sake of de new variants. ""So we go continue with perpetual boosters every 3 to 6 months so say we go maintain vaccine-induced immunity to de disease"" den bizz. According to de group, data available dey show say Ghana and Africa for instance dey manage de virus better pass de developed countries wey get vaccines. Rather, de rest of de world for learn from us. De Ghana Medical Association (GMA) distance dema body from de Concerned Doctors who dey petition against mandatory vaccination. According to de GMA, Covid-19 vaccines in de country be potent wey dem dey work. According to dem, data available dey support de efficacy and safety of all de Covid-19 vaccines Ghana dey use. Ghana Health Service announce say starting January year, dem go make Covid-19 vaccination compulsory give some citizens. Some of dis people dey include health workers, security officers, govment workers, commercial bus drivers den others go receive mandatory vaccination. Others wey go be affected be staff den students for secondary den tertiary and schools. According to Director-General for Ghana Health Service (GHS), Dr Patrick Kuma Aboagye, ""de Minister go make de effective date for that vaccination in January."" De mandatory vaccination however no dey affect just a section of de public, dem also dey target public places where masses dey gather like beaches, restaurants, nightclubs, stadia, govment offices den hospitals. Groups of people who dey find themselves for dis venues go also take de mandatory vaccination. Health Officials say dis be part of moves to prevent fourth wave of de virus, especially after de country record Omicron variant recently. Meanwhile, Ministry of Foreign Affairs extend travel ban on South Korea sake of Covid issues. Around December last year, dem announce de travel ban on South Korea and other counties which go last for 14 days. But in de latest update, dem extent de travel ban on South Korea to February 3, 2022." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59980250 +sports Meet di Champions League last 16 teams and top goal scorers We now know di teams wey go compete for di round of 16 for Champions League afta di group stage end on Wednesday night. Dis na di teams wey make to di knock round of Europe biggest football competition. Group winners (seeded) Group runners-up (unseeded) Di Champions League Round of 16 draw dey suppose take place on 7 November, 2022. E go shele for UEFA headquarters for Nyon, Switzerland. Di draw go take place exactly five days afta di end of di group stage fixtures on Wednesday, November 2. According to Uefa di round of 16 matches  go take place for February 2023. Di 2022/23 Champions League final go take place on June 10 for Istanbul Atatürk Olympic Stadium. Na dat be di, venue for Liverpool famous comeback victory ova AC Milan for 2005. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz49n1env11o +health Coronavirus: Ghana Prez Akufo-Addo enter 14-day isolation sake of Covid-19 exposure "Prez of Ghana Nana Akufo-Addo enter 14-day self-isolation after he make exposed to someone wey get Covid-19 within en close circles. Govment reveal dis filla for statement wey Minister of Information, Kojo Oppong Nkrumah sign on July 4, 2020. ""On de advice of doctors, de President of de Republic, Nana Addo Dankwa Akufo-Addo, from today, July 4, 2020, go take fourteen (14) day precautionary self-isolation measure in compliance with COVID-19 protocols,"" de statement add. Dem explain for de statement inside say ""de President decide say he go do so after at least one person within en close circle test positive for COVID-19 today."" Govment say de President test negative for Covid-19 as at today, but de Prez our of de abundance of caution wan isolate en body during dis period. During de time of de isolation, Prez go continue to work from en Presidential Villa for Jubilee House." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53296812 +politics "Edo election: ""Obaseki na dictator, no vote am""- Tinubu" "Di national leader of the All Progressives Congress (APC), Bola Tinubu, don ask voters for Edo State, western Nigeria, not to re-elect di current governor back to im seat as di leader of di state. Di current governor, Godwin Obaseki, dey seek re-election for second term for di election wey go shele on Saturday, September 19, 2020. Tinubu wey speak for one broadcast message for local television say Obaseki no be democrat. Obasaki be member of APC before e comot go opposition party, di Peoples Dmocratic Party, afta di party no gree allow am run for second term. APC instead give dia flag to Osagie Ize-Iyamu, wey contest di position before under umbrella of PDP. Tinubu now dey accuse Obaseki say im no participate for di fight wey bring democracy come Nigeria. He say, ""I wan appeal as person wey be democrat and leader of all democrats to di conscience and commitment to democracy, for di forthcoming election for Edo state, to reject Godwin Obaseki. ""I don suffer with many odas to bring about dis democratic time, wey be say today, we dey enjoy for di country. Den, Godwin Obaseki no participate for any aspect of di struggle to put democracy for di country. ""Therefore, he no understand di value and di pains wey dey with dis democratic struggle. ""He demonstrate di act of dictatorship, lack of respect for rule of law, lack of respect for you di pipo wey vote for those lawmakers wey im not sworn-in. ""Today, he now come back as democrat and wan make you vote am. Please, I appeal to you, reject am. Like he reject 14 members, make you reject am for di polls."" However, Obaseki don tok im own back, say Tinubu no go extend im power to Edo state. Tinubu na former govnor for Lagos State. ""Tinubu know clearly say come September 19, wen godfatherism go don dey dismantled for Edo State, di pipo of Lagos fit find formula to remove di grip wey im place on dia destinies for decades, hence di inciting television broadcast,"" na so Obaseki tok from statement wey im tok tok person release. ." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54167329 +sports Champions League group scores, results on Tuesday Napoli, Bayern and Clubbe Brugge maintain dia 100 percent record for Champions League on Tuesday night. All of dem don win dia three matches so far for dis season group stage of di competition. Tuesday fixtures see a total of 24 goals from di eight matches played. Ajax and Napoli game produce seven goals, di highest goal tally on Tuesday. Di group stage bin start on September 6 and e go end for November 2. Na February 14 di knockout stages go begin and end wit di final for Istanbul on June 10, 2023. Dis na some of di striking photos wey capture last night actions. Match day four go take play for October 11-12. https://www.bbc.com/pidgin/articles/ce94dd1llvvo +sports Manchester United v Man City: Ole Solskjaer Red Devils collect 2 - 0 beating from di Citizens for Old Trafford Manchester City use Manchester United play ten-ten for di latest match up for di Premier League in front of home fans for Old Trafford. E shock plenti pipo no be small wit di 2 - 0 defeat. In fact many pipo dey wonder wetin coach Solskjaer dey do sake of say, Man U neva lose dia derby for di last four games. Na Eric Bailly first spoil tins for di Devils wit own goal - e just turn Joao Cancelo cross into im own net afta seven minutes. Bernardo Silva come knack United akpako wen e net di second goal to secure di win for City. In fact, if no be be say David Gea bin do some kain beta beta saves, wit di way di Citizen dominate di match, many pipo believe say di scoreline for plenti pass. Di second half of di game just be like say United players no understand wetin dey play as City just just dey move ball up and down di field like say dem wan tear dia opponent net. As e be so, eyes go dey United to know wetin go be di future of coach Ole Gunnar Solskjaer sake di poor to average performance of di team dis season. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59191064 +sports Argentina vs Chile: Messi salute Diego Maradona statue for dia 1st World Cup qualifier afta im death "Lionel Messi score first-half penalty for Argentina before Chile Alexis Sanchez equalise as dia World Cup qualifier end 1-1 on Thursday. Messi convert di penalty afta Guillermo Maripan bring down Lautaro Martinez inside di box. Chile striker Sanchez level di score for di 37th minute, afta im finish off Gary Medel cut back from. ""E be very special game because na di first match without Diego,"" Messi tok. ""We know wetin di national team mean to am [Diego Maradona]. ""Even wen im no dey present for di stadium, im dey always support us. ""We bin want give him am victory and represent Argentina as im always do."" Di draw mean say Argentina dey unbeaten at home against Chile in 35 matches. And now do go 12 games without defeat since dem lose to Brazil for di 2019 Copa America semi-finals. Di match dem play for Santiago del Estero na Argentina first competitive outing since November and both teams bin look rusty. Argentina dey second for di 10-team South America qualifying group for Qatar 2022 wit 11 points from five games. Dem dey one point behind Brazil, wey go play Ecuador on Friday. While Chile dey sixth, wit five points from five games. Di top four teams go qualify automatically for Qatar while the fifth-placed side go into intercontinental playoff. Before di match, Argentina unveil statue outside di Unico Madres de Ciudades stadium for Santiago del Estero, to honour Diego Maradona. Maradona die at di age of 60 on November. 25 for Buenos Aires afta im suffer cardiac arrest. Di statue of Maradona, outside di stadium show am wit im hand for im waist and a ball for im feet. Di inscription read ""Diego Maradona, 1960-2020"" and symbol wey represent infinity." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57355083 +sports Afcon qualifier results: Comoros, Gambia make history as dem qualify for Africa Cup of Nations Comoros make history on Thursday wen dem draw 0-0 for dia home to Togo to qualify for di Africa Cup of Nations for di first time. Dem now dey celebrate one of di biggest achievements for di kontri wey don dey more famous for dia history of political coups and music than any sporting success. Wild scenes of celebration bin happun wen di ref blow di final whistle as fans, players and politicians begin celebrate di shock qualification for next year finals for Cameroon. Comoros bin never win any major qualifier until 2016 wen dem beat Botswana for wetin be dia 20th attempt to win either Nations Cup or World Cup qualifier. Five years on, they are top of Group G - featuring record African champions Egypt no less - with three wins and two draws from their five matches. Gambia secure dia first appearance when Assan Cessay goal for di 62nd minute seal dia 1-0 win over Angola. Perennial title contenders Egypt don also secure dia spot for Cameroon, alongside Tunisia, Mali, Guinea, Burkina Faso, Gabon, Zimbabwe, Equatorial Guinea and reigning champions Algeria. Ghana, Gambia, Senegal also don qualify for di tournament wey Caf bin postpone due to coronavirus. https://www.bbc.com/pidgin/sport-56534511 +entertainment New head of house BBNaija 2020: Trikytee na HOH, Laycon deputy, see BBNaija nominations today for Season 5 housemates eviction dis week Trikytee na di new head of house for Big Brother Naija Season 5 housemates. Dis na di first time Trikytee dey enta dis role as Head of House since di reality show start on 19 July, 2020. Trikytee wey real name na Timmy Sinclair win di roll of dice game for di head of house challenge wey di housemates play on Monday. Im get di highest score for di game to win di title of HOH for di week. As head of house, Trikytee get automatic protection alias immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge. Im pick Laycon as im deputy head of house and him go enjoy di same privilege wit Trikytee. Immediately afta di Head of House Challenge, Biggie call all di Housemates to each pick at least two fellow housemates wey dem go like to see leave alias possible eviction from di BBNaija Season 5 show dis weekend: Wen each of di nine remaining housemates enta di Diary room, dis na how dem nominate. Trickytee nominate Prince and Kiddwaya Vee nominate Prince and Dorathy Prince nominate Ozo and Nengi Dorathy nominate Kiddwaya and Neo Laycon nominate Ozo and Dorathy Kiddwaya nominate Vee and Prince Neo nominate Prince and Dorathy Nengi nominate Dorathy and Prince Ozo nominate Prince and Kiddwaya Based on di nomination process, di housemates put up Dorathy, Kiddwaya, Ozo and Prince for possible eviction dis week from di lockdown season. At least one of dem go leave di Big Brother house on Sunday during di live eviction show. As tin be Trikytee, Laycon, Vee, Neo and Nengi dey safe. You fit Like dis video: https://www.bbc.com/pidgin/tori-54065461 +entertainment Toyin Abraham and Lizzy Anjorin: Wetin cause dia gbas-gbas "Award winning Nollywood actress Toyin Abraham don beg her colleagues for di industry and Nigerians to stop to bully her son, Ire. Di actress for one Instagram live wey she do wit Iyabo Ojo dey vex say her beef wit anoda actress, Lizzy Anjorin wey happun for 2019 resurface again. Toyin born Ire, for her husband Kolawole Ajeyemi wey also be Nollywood actor for 2019 - di couple still dey together. ""Make Lizzy Anjorin stop to dey curse my son and my husband. Make dem leave my son. I no get any problem wit Lizzy wey go make her reign curses on my son,"" she tok. Toyin add say ""I be mother and wife and I go stand up for my son and my husband,"" Toyin tok as she hold Bible. For September 2019 one blog bin report say Law enforcement agencies gbab Lizzy Anjorin on top allegation of drug peddling for Saudi Arabia. Tori be say di blog also claim say na Toyin Abraham give dem informate about di arrest of Anjorin - na dis be di genesis of di fight. Di matter resurface two years after di alleged arrest of Anjorin as di actress go grant anoda blog interview about di matter. Anjorin for di interview insist say ""my investigation reveal say na Toyin leak my tori to di blog. ""Too much question go force me to release evidence fa..na wisdom dey help me keep some facts ...dat na why I dey work so hard like machine sake of tins about life dey bigger dan life gangan."" But Toyin Abraham at di time deny di allegation, ""I no know why she mention my name. Wetin she dey try achieve. Long ago I say bye bye to unnecessary drama and petty online/offline fight. ""Her so-called evidence of my involvement na comment wey I leave for di page of a fan wey she suspect say dey behind di story."" BBC never get hold of di latest interview wey Lizzy Anjorin grant di blog but Toyin Abraham for di Instagram live wey she do with Iyabo Ojo too say she no get business wit Anjorin wey go make her gossip di actress. ""Make dis Holy Bible judge me I no know Lizzy. She no be my friend. How I wan take know her movement about Saudi or no Saudi. Wetin con concern me. Make nobody curse my son because I no go gree,"" Abraham tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57252029 +business FTX former boss Bankman-Fried say e no try 'commit fraud' "Story by Ben Derico & James Clayton BBC News, San Francisco Sam Bankman-Fried, di former boss of collapsed cryptocurrency exchange FTX, say im no move any personal money out of FTX imsef. Di man wey pipo once hail as di 'King of Crypto' add say presently now, e dey left with ""close to nothing."" Oga Bankman-Fried also deny committing fraud. During im first public appearance since di collapse, Bankman-Fried tell di New York Times say e get ""bad month"" and get almost no money wey remain. FTX fall apart last month, afta dem bin dey valued at $32bn (£26.5bn). Many investors no dey able to withdraw dia funds from di global exchange wey now dey bankrupt. Bankman-Fried wey be 30 years old, also tok say im lawyers don advise am not to speak publicly, but e ignore dem. Speaking from di Bahamas, e tok say im get one credit card remaining wey get around $100,000 of debt inside. For di interview e tok say im no deliberately mislead investors, adding say: ""I no ever try to commit fraud."" However, wen dem ask am plenti times about details of money movements between FTX and oda entities, including di trading firm wey im own, Alameda Research, im at times no too dey clear in detail. E also tok say di company bin put body for ""greenwashing"" where firms dey engage in environmental projects for publicity. Plenti pipo bin see Bankman-Fried as a young version of legendary US investor Warren Buffet, and as recently as late October im get net worth wey dem estimate at more than $15bn. However, e tok say, e underestimate di sheer amount of cash wey dem need to cover FTX customers' withdrawals - leading to a run on di exchange. Many crypto firms don try struggle with di downturn for di broader economy and as concerns dey ground about di viability of crypto currencies. FTX declare bankruptcy soon afta Bankman-Fried step down as CEO on 11 November. According to one court filing earlier dis month, FTX currently dey owe dia 50 largest creditors almost $3.1bn. Bankman-Fried don become well known for Washington DC as political donor, supposedly supporting pandemic prevention and improve crypto regulation. But for im tok with Times reporter Andrew Ross Sorkin, Bankman-Fried confess say much of im Washington DC work don be PR ""masquerading as do-gooderism."" Bankman-Fried tok say for now e no dey concerned about potential criminal or civil liability. ""Time and place go dey for me to think about mysef and my own future,"" e tok afta starting and stopping several times. ""I no think say dis na di time."" Wen dem ask am if e dey truthful for im responses, Bankman-Fried tok say e dey as truthful as e knowledgeably fit be. ""I no know of times wen I lie,"" e tok. Though e no provide evidence to support am, SBF tok say e believe FTX US bin dey kampe and fit in fact pay back American investors." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd123nq7zd6o +politics Osun election: Five tins you fit no sabi about Osun govnor-elect, Ademola Adeleke Di Independent National Electoral commission wey be Nigeria election umpire on early mor-mor Sunday declare Senator Ademola Adeleke as di govnor-elect afta emerging winner for di July 16 gubernatorial election for Osun state. Adeleke, 62, poll 403,371 votes to defeat im closest rival and present govnor of di state Gboyega Oyetola wey poll 375,027 votes. Dis na di second time wey di two politicians go dey go head to head for election. Dem first meet for 2018 wen Oyetola defeat Adeleke afta Inec declare di election inconclusive sake of say di marging wey Adeleke take beat Oyetola no reach di numbers of votes wen dem bin cancel. Oyetola come beat Adeleke for di run-off. Adeleke dey popular for im dancing skills and vibes but plenti oda tins dey wey many pipo fit no know about am. https://www.bbc.com/pidgin/62195437 +entertainment 2022 Cannes Film Festival: How di famous Cannes Film Festival dey embrace Bollywood "Bollywood siddon in all im jewel and dimple glory for di high-table of world cinema on Tuesday as actress-star Deepika Padukone join di nine-member jury for di 75th Cannes International Film Festival for France to tok to tori pipo dem. Di jury,wey French actor Vincent Lindon head, go watch 21 films and pick one wey get Palme d'Or, di film world most prestigious trophy for di best film. Ms Padukone, 36, bi Bollywood highest paid actress wey pipo sabi for her role inside Padmaavat, Piku and most recently Gehraiyaan, say she dey look forward to watch films, ""enjoy dis creative process and hug di experience"". Ms Padukone go be di pesin wey pipo snap photo and tok about past for Indian star for di Cannes Film Festival dis year, but she no be di only one wey add Indian flavour to di world most well-regard and grand celebration of films. Close to where Ms Padukone go dey watch and judge films, one Indian movie group, wey India minister for Information and Broadcasting Anurag Thakur lead, don land for pitch for business for di Marché du Film, di world biggest film market wey run same time wit di Cannes Film Festival. Every May, di upmarket but easy going coastal resort of Cannes for di French Riviera take dia time to mix,dem move from dia own lazy, even no ginger as di film festival dey draw close. Di annual worry be both real and understandable as about 120,000 pipo land for di town of 74,000 to attend di Cannes Film Festival. Di Festival wey dey celebrate diart of filmmaking, and Marché du Film wia deals wey worth millions dey strike for di sale, distribution and marketing of films. But dis year, as di town show from lockdown and trauma wey Covid-19 cause, e get different vibe. All masks dey off and ginger dey to return to normal. And to renew dia romance wit di movies, Cannes dey for tight hug wit movie-crazy India. Dis year India, di world biggest producer of films, don make di ""Kontri of Honour"" for Marché du Film. As di first kontri to gbab di courtesy, India go gbab di stage, to show off dia talent. Indian directors, producers and distributors go get opportunities to pitch dia films to new markets and explore collaborations. ""India get plenti stories to tell and di kontri truly get di great potential to become di content hub ofdi world,"" Oga Thakur bin tweet, e quote Indian Prime Minister Narendra Modi. To support im case, Oga Thakur don bring along some new films, actors and Oscar-winning music composer A.R. Rahman wey, in turn, don bring along im film, Le Musk. one 36-minute-long virtual reality (VR) mystery wey set around romance wey im bin write and direct, Le Musk be one visual and sensory experience wey pour our some different scents, including one of Rahman favourite, sandalwood. Di film dey set to get world premiere for di Cannes Film market. Anoda Indian film wey many dey wait for, im world premiere go shelle for di film market na Rocketry: Di Nambi Effect. Di directorial debut of Tamil and Bollywood actor R. Madhavan, Rocketry be documentary about Nambi Narayanan, one Indian aerospace engineer wey dem falsely accuse of spying, e bin chop arrest, abused and later clear am. Di film get cameo by actor Shah Rukh Khan. Di Cannes festival, wey run from 17 to 28 May, get exciting line-up of world premieres of di biggest Hollywood films (Tom Cruise Top Gun: Maverick, Baz Luhrmann Elvis), master classes by some of di most talented actors (Javier Bardem and Mads Mikkelsen, among odas), di best of arthouse cinema as well as two Indian classics wey dem bring back. Satyajit Ray 1970 film, Pratidwandi (Di Adversary), and G. Aravindan Thamp (Di Circus Tent) go dey screened for festival and tickets dey hard to come by. But di most delightful and surprising Indian presence for Cannes dis year be one documentary about two Delhi-based brodas' efforts to save birds -clearly, di black kite - wey dey slayed by di city rising pollution. Shaunak Sen brilliant film, All dat Breathes, wey premiere for di Sundance Film Festival earlier dis year, go dey screened as part of di Cannes film festival official selection. Dis be uncommon departure for Cannes, wey get reputation say e be proudly exclusive and no dey usually consider films wey don play elsewhere. ""I no expect say di film go dey for Cannes. Not small sake of say we bin get di great fortune to premiere and win di Grand Jury award for Sundance, and e dey exceptionally uncommon for film wey dem no go premiere for Cannes to play for Cannes... We dey beside ourselves wit joy,"" Sen tell BBC Africa. All di Breathes dey among 12 films wey go play for di non-competition section, alongside Ethan Coen first solo directorial venture, Jerry Lee Lewis: Trouble in Mind. Anoda Indian film for Cannes' official list dis year be Nauha. Made by Pratham Khurana, one 23-year-old film school student, di 26-minute short, Nauha (wey mean ""mourning"" for Hindi), be about one young boy wey dey take care of one 75-year-old manwey wan die. Picked out of more dan 1,500 entries wey dey submitted by film schools from across di world,e be one of 16 films wey dey compete for one award. Ms Padukone, meanwhile, look one tad overdressed but stunning for one headband and one chunky golden necklace wey look like say e dey drip precious stones. But she dey all set to take di role of juror she tok. She add say while she dey watch films, she go try ""forget say we actually get dis burden and responsibility"" to pick one winner, and instead keep am for mind di ""audience...say young pikin wey don grow up dey watch movies and dey gingered"". ""I think say cinema be one kind powerful tool and di kind powerful medium. E be di ability to impact and transform pipo lives,"" Ms Padukone tok." https://www.bbc.com/pidgin/sport-61490626 +sports Odegaard: Arsenal sign Martin Odegaard from Real Madrid for about £30m as Aaron Ramsdale complete medical "Arsenal don sign midfielder Martin Odegaard from Real Madrid for about £30m and dey close to complete deal for Sheffield United goalkeeper Aaron Ramsdale. Norway international Odegaard, 22, spend di second half of last season on loan for Emirates. Im make 20 appearances in all competitions and score two goals. England Under-21 international Ramsdale make 38 Premier League appearances for di Blades last season. Im go join Bernd Leno and Runar Alex Runarsson as Arsenal goalkeepers. ""Some paperwork still dey to work out but e don do im medical, still a few things to sort with Sheffield,"" Gunners boss Mikel Arteta tok. ""Aaron na talented young keeper with huge experience and get international experience for England. Im go bring competition and dat na wetin we want create - healthy competition, quality competition for every position. We identify Aaron as di ideal option."" Odegaard join Ben White, Albert Sambi Lokonga and Nuno Tavares as Arsenal signings dis summer. Im no go dey available for Sunday Premier League match with Chelsea as e dey wait for visa clearance. Asked wetin Odegaard go add to e squad, Arteta add say: ""A lot of things wey e bring last season, im make us better, we need more options and alternatives for creativity. ""Im still dey really young but im get huge experiences for clubs already and get unique talents for du way e want to play so I really dey happy say di club don make di effort."" Di Norwegian join Real Madrid from Stromsgodset for 2015 but only make eight league appearances for di Spanish side. Im also spend time on loan wit Heerenveen, Vitesse and Real Sociedad. Arteta bin make am clear for di end of last season say e want Odegaard to return to di Emirates on permanent basis, and don also speak about wanting to add more new signings to e squad before di transfer window close on 31 August." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58279200 +entertainment Actress Pat Ugwu: Instagram twerking dance video of Nollywood actress wey show her bumbum and naked bodi for IG live vex some fans "Twerking dance steps wey Nollywood actress Pat Ugwu throw almost naked for her Instagram Live no go down well wit some fans. Pat Ugwu na one of di many Nigerian actress dem wey dey always post naked foto and videos wey dey make pipo tok . Latest tori be say di actress strip to her underwear as she twerks for her fans on Wednesday for di latest Instagram Live wey di Nollowood star do to show her followers another side of her. But e no go down well wit all di fans, e don even cause controversy again. Inside di video wey BBC Pidgin see, Pat dey rock wit some kain skimpy underwear as she twerk inside her room during di Instagram Live. Tori be say no be today wey di actress don begin expose herself everi now and then for social media. Almost a year ago ,Pat Ugwu share naked video of herself dancing wey later appear on many porn sites. Dis Nollywood actress don declare her sef as di CEO of bumbum. For one old interview wit one Nigerian local media, she say ""You all know say my selling point, na my 'Ikebe'" https://www.bbc.com/pidgin/world-53934791 +entertainment "Naira Marley: Jude Chukwuka AKA Fada Maler say ""I be Marlian for life""" Producers: Ronke Alo, Gift Ufuoma Jude Chukwuka AKA Fada Marley wey be Nollywood actor tok why im dey sing Naira Marley songs at im age. Naira Marley wey real name na Azeez Fashola na popular Nigerian afro beat singer. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53509788 +entertainment Burna Boy: Grammys, awards, collabo and oda tins wey im don achieve for music "Nigerian singer and songwriter, Burna Boy say im be di best for Nigeria music industry. For tweet wey im share on Tuesday , e say after Afro beat legend, Fela Anikulapo Kuti, na im be di best musician for di kontri. After one twitter use reply am say na pipo pave way for am for di music industry before im fit shine, im reply say nobody pave way for am. Dem born Damini Ebunoluwa Ogulu for July 2 1991 for Port Harcourt, Rivers State Nigeria. Pipo begin hear Burna music for 2013 afta im release ""Like to party"", di lead single inside im album wey im tittle L.I.F.E since then, im don release Four studio Albums. For 2019, Burna na one of di artiste wey dem pick from Nigeria, to go represent West Africa to perform for Coachella Valley Music and Arts festival. Di music festival be one of di biggest festivals for di whole world. For di same year Im record ""Ja Ara E"" wey e mean ""wise up"" or you fit call am ""use your head"") for Beyoncé's Di Lion King: Di Gift and na im be di only guest artist with their own track on di soundtrack album. For July 2019, dem announce Burna as Apple Music Up Next artist. Im don do collaboration with plenti ogbonge artiste inside and outside Nigeria since im begin dey popular for 2012. For January 2018, Burna Boy feature for ""Sunshine Riptide"", oene track from Fall Out Boy's seventh studio album MANIA. Im don collabo with international artiste like v J Hus, Lily Allen and Mabel. Ed Sheeran, Stormzy, Wretch 32, IDK, Jorja Smith, Beyoncé, Mahalia Burkmar, Dave amongst oda pipo. 2013 South South Music Awards - Best Pop 2013 Nigeria Entertainment Awards - Best New Act of the Year 2015 Nigeria Entertainment Awards - Best Album of the Year 2015 Soundcity MVP Awards Festival - Listener's Choice, Song of the Year, Best Male MVP, African Artiste of the Year 2019 BET Awards - Best International Act 2019 Di Headies - Song of di Year, Best Collaboration 2019 MTV Europe Music Awards - Best African Act 2019 African Muzik Magazine Awards - Artiste of di Year 2019 All Africa Music Awards - West African Male Artiste of di Year, Album of di Year 2019 Soundcity MVP Awards Festival - African Artiste of Di Year, Best Male MVP. 2014 Headies Awards -Next Rated 2014 MTV Africa Music Award- Best New Act 2014 Headies Awards- Best R&B Single, Best R&B/Pop Album, Hip Hop World Revelation of di Year and Album of di Year 2015 Nigeria Entertainment awards- Best Pop Artist of di Year 2019 Di Headies- Viewer's Choice, Best Recording of Di Year, Best Pop Single, Best R&B/Pop Album, Album of di Year 2019 African Muzik Magazine Awards- Best Collaboration, Video of di Year, Best Live Act, Best Male West Africa and Crossing Boundaries with Music 2020 Soundcity MVP Awards- Best Collaboration, Listeners' Choice and Viewers' Choice. Recently, dem nominate Burna Boy 'African Giant' Album for Grammys 2020 awards for Best world music category along oda popular artiste like Angelique Kidjo, but im no win am" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51485301 +politics APC postpone Bayelsa governorship primaries, set new September date Di 2019 Bayelsa Governorship Primaries of di All Progressives Congress wey suppose hold on Saturday 31 August don get new dates. E go now hold on two days - 3 September and 4 September, according to di party National Working Committee (NWC). Di National Publicity Secretary of di party, Lanre Issa-Onilu announce di new dates for di APC twitter handle. For earlier statement wey secretary of di Bayelsa APC Governorship Primary Election Committee, Emmanuel Ochega sign, di committee get to postpone di party primary sake of two orders from courts of same level, wey one dey tok one tin and anoda dey tok anoda tin. Di statement go on to assure party members and aspirants say di 2019 Bayelsa APC Governorship Primary Election go hold within di time frame wey di Independent National Electoral Commission INEC give. Na six aspirants dey contest di primaries and dem include di immediate past Minister of State for Agriculture and Rural Development, Senator Heineken Lokpobiri, Oil surveillance contractor, David Lyon, one former Commissioner for di State, Prince Ebitimi Amgbare, one businessman Preye Aganaba and two women, former Commissioner of Police, Mrs Diseye Nsirim Poweigha and Prof. Ongoebi Maureen Etebu. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49526590 +business Ghana, Germany relations: Akufo-Addo Ghana plus Angela Merkel German ties explained "Ghana plus Germany relations be of utmost importance, President Nana Akufo-Addo declare dis week. But wen plus how de west African gold coast and de Western European industrial nation start dis relation? President Akufo-Addo say Ghana dey draw inspiration from de success tori of North Rhine-Westphalia and Germany. North Rhine-Westphalia be Germany's most populous and industrial region. ""We desire to walk hand-in-hand with North Rhine-Westphalia and Germany sake of ""we share attachment of common values. ""And respect for individual liberties and human rights, respect for rule of law and respect for human principles of democratic accountability"". President Akufo wey country dey against gay and LGBT+ pio tok for speech for dema 75th anniversary celebrations. He continue tok say ""we want to build progressive and prosperous nation"". But for de same occasion, Ghanaians in Germany shouted at Akufo Addo to fix de country so demma fit return home. According to Akufo Addo, Ghana be determined say dem go participate fully for de global market place for de basis of things de country dey produce and not for raw materials export. De president tok all dis sweet things wen e meet German Chancellor, Dr. Angela Merkel dis week for Dusseldorf wey dey Federal Republic of Germany. Ghana plus Germany diplomatic relations dey more than 60years. Since Ghana independence, de two countries bilateral development cooperation dey exceed 1.5 billion euro. Ghana plus Germany dey collaborate on a number of diversified interests like youth development, entrepreneurship and on de environment. So far, Germany be one of de main vehicle suppliers to Ghana. De president tok say de establishment of big companies like Volkswagen car assembly in Accra be welcoming news wey more companies dey ready say dem go come Ghana come set-up. Akufo Addo further tok say na im priority be say dem go increase trade and investment cooperation cos dat be one of de way dem go develop healthy economic relations with North Rhine-Westphalia and Germany and de rest of de world. If Ghanaian products be high for global value chain, na im go create jobs give de teeming youth. President Nana Addo extend wishes on behalf of de Economic Community of West Africa States (ECOWAS) wey im be chairman, to de people of North Rhine-Westphalia." https://www.bbc.com/pidgin/media-58339455 +entertainment AKA: 'Every day dey feel like mountain to climb'- South African Rapper Kiernan Forbes break im silence afta fiancée, Nellie Tembe die "South African rapper, AKA wey im real name na Kiernan Forbes don speak out for di first time afta di death of im fiancée, Anele 'Nelli' Tembe. Anele Tembe wey AKA bin engage for February 2021, die on Sunday April 11th afta she fall from di 10th floor of one Cape Town hotel. Di rapper wey neva tok since Anele die, finally tok for one recent statement say since di death of im fiancée, every day feel like mountain for am to climb. ""I don lost di love of my life… and every day feel like mountain to climb. I miss Anele, so much, and I dey heartbroken for di unfulfilled life we bin don plan togeda,"" AKA tok. Kiernan Forbes say di death of Anele don affect am well-well, both emotionally and psychologically. E add say di Insinuations and side tok from pipo don even make am more difficult to think well and di stress im families don pass through sake of dis don dey too much. ""...dis na why at dis time I choose to withdraw to honour my journey, and pray say di moment of stillness go bring me closer to some clarity."" AKA later come use dis opportunity thank im friends, fans and family for dia support to am during dis difficult times. ""I wish to convey my gratitude to all the people who have supported me during this difficult time in my life; my mom, Lynn, and dad, Tony, Bab' Moses and Ndabezitha, my brother, Steffan, my family (both Forbes and Tembe), my heartfelt gratitude to you all. Di rapper say im don hand over give im team di work to handle all im affairs for public including e social media platforms and plead with pipo for public to respect e privacy for dis period wey e dey mourn." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56861739 +sports Ronaldo fit leave Man Utd dis week, Newcastle wan sign Bakayoko "Chelsea go follow up di £70m signing of Leicester French defender Wesley Fofana, 21, by pushing to get transfer of Barcelona Gabon forward Pierre-Emerick Aubameyang, 33, over di line. Di Blues also wan sign Everton's 21-year-old English winger Anthony Gordon dis week. (Guardian) Tottenham dey in talks about potential loan move for Leeds United and Wales winger Daniel James, 24, before Thursday 23:00 BST transfer deadline. (Fabrizio Romano) Meanwhile, Spurs don reignite dia interest in Atletico Madrid versatile Belgium midfielder Yannick Carrasco, 28. (Telegraph - subscription required) Cristiano Ronaldo fit leave Manchester United for Napoli this week. United Portugal forward, 37 start just one Premier League game dis season. (Metro) Aston Villa have ""strong interest"" for Brighton boss Graham Potter as potential replacement for Steven Gerrard, who lose three of im first four league games dis season. (Football Insider) Newcastle dey keen on Chelsea French midfielder Tiemoue Bakayoko, 28, who dey on two-year loan for AC Milan. Nottingham Forest also dey keen. (Calciomercato - in Italian) Crystal Palace don make £27m offer to buy Chelsea's 22-year-old England midfielder Conor Gallagher, who impress while on loan with di Eagles for 2021-22. (Times - subscription required) Arsenal Spain defender Hector Bellerin, 27, fit join Real Betis, where e dey on loan last season. Bellerin neva play for di Gunners since May 2021. (Estadio Deportivo - in Spanish) Barcelona and the Netherlands midfielder Frenkie de Jong, 25, go remain for di club despite link with Manchester United and Chelsea during dis summer transfer window. (Football Espana) Aston Villa and Wolves both dey interested in signing West Ham's English defender Craig Dawson, 32. (Sun) Juventus go try sign Aston Villa Brazil midfielder Douglas Luiz, 24, if dey no fit strike agreement with Paris St-Germain for Argentina Leandro Paredes, 28. (Sky Sport Italia - in Italian) Liverpool and the Netherlands Under-21s defender Sepp van den Berg, 20, dey set to join Schalke on loan. (The Athletic - subscription required) Leicester City dey in talks with Schalke to sign Morocco midfielder Amine Harit, 25. (Sky Sports) Fulham don agree deal with Paris St-Germainto sign French left-back Layvin Kurzawa, 29, while di Cottagers dey also make efforts to bring in Roma 23-year-old Dutch winger Justin Kluivert. (Mail)" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c14ql4grwwno +sports Roger Federer go miss di rest of di 2020 tennis season? Dis na wetin we know "Di 20-time Grand Slam winner do di first arthroscopic surgery for February but said im suffer ""setback"" with im rehabilitation. Professional tennis don dey suspended since March because of di coronavirus pandemic. ""I go look forward to see everyone back for tour for di start of di 2021 season,"" di 38-year-old Swiss say. Federer never play since im lose to Novak Djokovic for di Australian Open semi-finals for January. He miss di majority of di 2016 season sake of knee injury, but im return di following year to win di Australian Open and Wimbledon. ""Few weeks ago, sake of setback during my first rehabilitation, I need do additional fast arthroscopic procedure to my right knee,"" Federer tok for Twitter on Wednesday. ""Now, as I do before 2017 season, I go take di necessary time to dey 100% ready to play at my highest level."" Di ATP Tour dey shut down until at least di end of July becos of di pandemic, with di US Open scheduled to start for 31 August and di French Open beginning on 20 September." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52999742 +sports Tiger Woods: Eldrick Tont health condition afta February car crash for Los Angeles "Tiger Woods don post picture of imself for golf course as e dey smile with crutches and im dog. Dis go be di first time di 15-time Golf Major winner go show picture of imself since im bin wound for one car accident for February. For di Instagram post im bin write say, ""My course dey come faster than me"". E also add say, ""But e dey nice to get faithful rehab partner wey be man's best friend"". Di 15 time major champion bin do surgery for di open fractures for im lower right leg. Di former world number one, bin also get surgeries on top oda injuries im bin get for im foot and ankle. Tori be say na earlier dis month dem bin even release am from hospital. Tiger Woods bin dey drive almost double di speed limits for California wen di car hit tree and start to dey tumble several times. According to di LA County sheriff Alex Villanueva, di cause of di accident na say im bin dey drive for speed way bin no safe with di way di road be. Tori be say im bin no even match brake during di ordeal and police tok say e fit because of di shock and panic wey catch am for di incident." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56859208 +entertainment Paul Okoye marriage: Anita Tonye Isama, Rude Boy Paul Okoye wife biography "Anita Okoye, Paul Okoye wife once write say ""I be one of di STRONGEST Mothers!"" Today di mother of three fit dey face a test of her strength. Dis na as Paul Okoye [former P-Square] and Anita Tonye Okoye marriage fit don hit rock. Tori of dia alleged divorce na im Nigeria local media dey report since Friday 20 August, 2021. Paul Okoye na popular Nigerian music star but who be Anita Tonye Okoye? Kack make BBC Pidgin yan give wetin we find out about Anita Tonye Okoye profile. Anita Tonye Okoye na a lawyer, social activist and entrepreneur. She dey well-known as di wife of Paul Okoye. Born on 8 November 1988 as Anita Tonye Isama, she now be indigene of Anambra state. She marry Paul of P-Square on 22nd of March 2014 for Aztech Acrum, Port Harcourt. She study law for University of Abuja wia she meet Paul Okoye before dem marry. Paul Okoye and Anita Okoye meet in 2004. Dem become parents to a son in 2013 and marry a year later. Anita Tonye Okoye do Masters in Oil and Gas from di University of Dundee, Scotland. She work inside Oil and Gas industry for about eight years. She work for AMG Petronergy Limited as Project Manager from 2010 to 2013. And as Business Development Executive for Desicon Engineering Limited from 2014 to 2018. Anita Okoye na di co-founder of di Cashew Apple Project. Dat na initiative wey focus on contributing to change how di world dey perceive Africa. She be Social Justice Ambassador for ActionAid Nigeria to campaign for children health. Anita also be di founder of a children fashion store called TannkCo in Lekki, Lagos. She be di CEO of TannkCo wey launch in 2019 as children's wear brand based in Lagos. She also be di co-founder of a lifestyle furniture company for children, named Little Luxe. On Friday August 20, 2021 social media in Nigeria flood wit one foto of di alleged petition from one Abuja High Court. Di reported foto show Anita allegedly planned divorce to her husband, Paul, but BBC Pidgin never fit verify di foto. Paul and Anita marry for 2014 and dem get three children together. Di first rumours of di couple alleged separation bin come out for April 2021. Dat time Anita relocate to di United States. Di alleged divorce begin spread afta document wey be like Anita Okoye petition to leave her marriage appear online. BBC Pidgin visit di Abuja High Court wey di document come out from but di court officials no fit trace di document. But so far, no representative of Paul Okoye don come out to either confirm or dismiss di rumours wey dey spread fast. Di Nigerian music star im sef, Paul Okoye also never drop any hint about di tori wey dey fly around. Anita Tonye Okoye wey dey at di center of dis tori also never confam or dismiss di alleged divorce document. But on Friday morning she post music of Paul Okoye wit foto of him and a lady ontop her Instagram story. BBC Pidgin contact Paul twin brother, Peter Okoye wey say ""we no get permission to discuss dis matter abeg""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58276095 +health Omicron: Why Nigeria dey di travel red list? "Nigeria dey UK travel red list - move wey United Kingdom goment tok say go help slow di spread of di Omicron variant. But di Nigeria High Commissioner to London, Ambassador Sarafa Tunji Isola say di travel restrictions na ""travel apartheid"". So why Nigeria dey di red list, and e dered list 1y fair? Wetin be red list? Nigeria na di latest African kontri to join UK travel red list - wit South Africa, Namibia, Zimbabwe, Botswana, Lesotho, Eswatini, Angola, Mozambique, Malawi and Zambia. Di only pipo wey dey allowed to enta UK from dis kontris na UK or Irish citizens, or UK residents. Pipo wey arrive from red list kontris go need to enta hotel quarantine - wit dia own moni - and isolate for 10 days. Dem dey target dis kontris sake of Omicron variant wey dem first identify for southern Africa. But di fact say all di kontris wey currently dey di list na from Africa, don dey criticised as ""wicked and unfair"". Di decision to put kontri for dis list dey based on risk assessments from di Joint Biosecurity Centre (JBC) - one scientific body wey dey advise goment. Dis assessment include: Di UK goment tok say dem add Nigeria to di list be say: Di JBC report summarise informate wey dem use make specific decision for each kontri, but dem neva publish di one for Nigeria. UK goment statement wey announce Nigeria addition to di red list said ""majority"" of Omicron variant cases for UK ""get clear links to overseas travel from South Africa and Nigeria"". Reported Covid cases for Nigeria dey far lower compared wit most of Europe, wia dem dey identify around 90 cases a day ova di past week - but testing for Africa dey way below Europe levels. During di last week of November, Nigeria do about 0.07 tests per 1,000 pipo a day, as dem compare am wit about 14 per 1,000 for UK and about 8 per 1,000 for France. Nigeria still identify fewer cases per test for week wey enta 2 December dan several oda European kontris plus South Africa wia dem first detect Omicron. Based on test mata, all kontris dey collect and share data differently and dis dey make am tricky to compare internationally. UK goment collect data on pipo wey test positive for Covid afta dem arrive UK. Di latest informate or data wey we get from di beginning of November, wey show percentage of pipo wey test positive afta dem travel from Nigeria dey around 1% - similar to several European kontris. Nigerian Centers for Disease Control (NCDC) don identify only three cases of Omicron for di kontri, all of dem dey linked to travel from South Africa. Dis na fewer cases dan several European kontris, including UK wia dem don report 336 Omicron cases. However NCDC data dey five days old, so di numbers fit don go up since. Genome sequencing - di process wey dem dey use to identify variants of virus - no dey advanced for Nigeria compared wit UK or South Africa, for example. Dis fit mean say dem no fit effectively tell di extent of di spread of Omicron. Di genome sequencing wey dem need to identify new variants dey very sophisticated and e rare. Di Department of Health say for England, 21 Omicron cases get link to travel from Nigeria. Kontri vaccination rate na also wetin dem dey consider before restricting travel, although dis na just ""contextual information"" plus genome sequencing ability and Covid transmission. Vaccination rates for Africa dey well below di world average. For Nigeria, as of 5 December, na just 4.8 doses dem don give per 100 people, compared with more than 178 per 100 people for UK." https://www.bbc.com/pidgin/world-59551630 +politics Buhari in Ondo: Goment declare public holiday to welcome di president Di Ondo state goment for South-west Nigeria don declare Tuesday, February 25, 2020 as public holiday as di state dey welcome di kontri President Muhamadu Buhari. Di state Governor Arakunrin Akeredolu bin invite di president to commission some projects as part of jolliment to mark im third year for office. Di state communication office announce say all state workers no go report to work during di holiday to welcome di president. President Buhari dey go launch di Ore Industrial Hub and one interchange bridge. Di jolliment to celebrate Governor Akeredolu third year for office bin start on February 21 to end on March 1, according to one programme of events wey dem share on social media. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51628363 +sports 2022/23 Premier League opening day fixtures and key dates Champions Manchester City go travel to West Ham for di opening weekend of di 2022-23 Premier League. Di new campaign get mid-season break to accommodate di World Cup for Qatar. Games no go dey afta di weekend of 12-13 November until 26 December because of di World Cup. Di first fixture go take place on Friday, 5 August and na Crystal Palace against Arsenal. Liverpool go play newly promoted side Fulham, while Nottingham Forest go jam Newcastle. Forest dey return back to di Premier League for di first time since 1998-99. Di World Cup, go feature both England and Wales, e go start on 21 November. Na 18 December dem go play di final, eight days before di Premier League season resume. No meetings between di Premier League so-called 'big six' on di weekend of 12-13 November – di one before di World Cup – sake of request by di Football Association. England go meet up on 14 November before dem fly to Qatar di following day. Special arrangements dey ground to allow more time between games wey dem go play across di three festive match rounds. Dis go allow squads more time to recover. Previously clubs get a minimum of 48 hours between matches. After fixtures on 26-27 December, di following match go shele from 29, 30 and 31 December. Di New Year match go happun on 2, 3, 4 and 5 January. Friday, 5 August Crystal Palace v Arsenal Saturday, 6 August Fulham v Liverpool Bournemouth v Aston Villa Leeds United v Wolverhampton Leicester City v Brentford Newcastle United v Nottingham Forest Tottenham Hotspur v Southampton Everton v Chelsea Sunday, 7 August Manchester United v Brighton West Ham United v Manchester City Di 2022-23 season get few adjustment to accommodate di 2022 World Cup, wey go take place in di middle of di domestic calendar. E dey starts a week earlier than normal - 75 days afta di final day of di 2021-22 campaign - and finish a week later than usual on 28 May. Fifa, world football join body, don already tok say dem must release players on 14 November for di World Cup. E mean say mid-season break go last more than six weeks. Also na 16 matchdays dey before Qatar - five for August, three for September, six for October and two for November. Bournemouth v Everton Brighton v Aston Villa Fulham v Manchester United Liverpool v Southampton Manchester City v Brentford Newcastle United v Chelsea Nottingham Forest v Crystal Palace Tottenham Hotspur v Leeds United West Ham United v Leicester City Wolverhampton v Arsenal Manchester City, di 2021-22 champions collect di crown afta dia dramatic final-day win ova Aston Villa. Na dem still be favourites to retain di title afta dem sign striker Erling Haaland from Borussia Dortmund for £51.2m. Haaland wey be 21 years, dey set to make im Premier League debut for West Ham before City host Bournemouth and then travel to Newcastle. Liverpool, wey finish one point behind di champions for 2021-22, go host City on 15 October, di return fixture go happun for Etihad Stadium on 1 April. Afta dem open dia season wit Newcastle, Nottingham Forest go host West Ham before dem travel go Everton. Di first Manchester derby of di season na for October 1, for Etihad Stadium, den United go host dia neighbours again on 14 January. Arsenal go play dia first north London derby of di season on 1 October wit di return leg for Tottenham also on 14 January. Di first Merseyside derby of 2022-23 na for Everton stadium on 3 September di return leg for Liverpool go happun on 11 February. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c3g01z492gdo +entertainment DMX: US rapper DMX don die at di age of 50 "US rapper and actor DMX don die at di age of 50, five days after him suffer heart attack. Di performer, wey im real name na Earl Simmons, bin don dey on life support for some time but him die with im family by im side. Di family for di statement wey dem release say DMX ""na warrior wey fight till di very end"". ""Earl's music inspire countless fans across the world and his iconic legacy will live on forever."" DMX former manager Nakia Walker bin describe di rapper as person wey dey ""vegetative state"" with ""lung and brain failure"", dat na when report come out say im dey life support. DMX, aka Dark Man X, na leading hip-hop performer wey collaborate with artists like JAY-Z, Ja Rule and LL Cool J. Im get im stage name from di name of drum machine wey dem dey use for rap tracks. Di chart-topping artist songs include Party Up (Up in Here) and X Gon' Give It To Ya. Im also act on screen, when im appear for films like Cradle 2 di Grave, Romeo Must Die and Exit Wounds. Born in Mount Vernon, New York for 1970, DMX publicly battle substance abuse for years and im bin spend several periods for rehab. Im be father of 15, DMX serve jail sentences on charges wey include animal cruelty, reckless driving, drug possession and weapons possession. According to his family, DMX die on Friday for White Plains Hospital for White Plains, New York." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56694719 +sports Paul Pogba contract coronavirus: Manchester United midfielder test positive for Covid 19 "Paul Pogba catch coronavirus na di latest from Manchester United camp. Tori be say di midfielder Paul Pogba don test positive for coronavirus according to France manager Didier Deschamps. Di 27-years-old go now go stay for separate room alias self-isolation for 14 days. Paul Pogba go miss France Nations League game against Sweden on Saturday, 5 September and di match against Croatia three days later. Dis tori of Pogba coronavirus status dey come only weeks before di Premier League new season go start on September 12. However, di midfielder fit still dey ready alias eligible for selection for United first game of di season against Crystal Palace for Old Trafford on 19 September. Im club Manchester United say: ""Everybodi for United wish Paul speedy recovery ahead of di new season.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-53936269 +entertainment Brunella Oscar, Williams Uchemba traditional marriage photos, tori and messages from celebs "Some Nigeria celebrities don shout big congratulations to popular Nigerian child actor wey don turn comedian now, Williams Uchemba as e do im traditional marriage ceremony to e sweetheart Brunella Oscar over di weekend. Comedian Ayo Makun AKA A.Y share di traditional marriage foto of di couple and wish dem God blessings while musician J Martins wish Uchemba wey e call 'childhood' friend and 'brother' happy married life. Di traditional marriage between Williams Uchemba and Brunella Oscar take place for Alor, Anambra state, wia im wife from come. Dis dey happun afta some weeks ago wey Williams Uchemba bin propose to Brunella and post give im fans for social media say time don reach for am to settle down. E later come reveal say di white wedding go take place November 21, 2020 wia di ogbonge showdown go happun live with enof groove. Uchemba wife na physician for Hill York Medical. Williams Uchemba start im career for movies for early age wia im gain popularity for films like 'Beyond Belief' and 'The World of Riches.' E recently come back as social media comedian wey popular sotey e carry am enter music with im popular catch phrase, ""I don't like what I hate."" For 2018, Actor Williams Uchemba win Individual Social Philanthropist and Best of Social Media award. Uchemba na im bring di social media campaign, 'Project One Million' come wey wan helep poor pipo comot poverty through education and skills plus including how poor pipo fit get cheap house so evri bodi go get roof on top dia head. Later dat year 2018, one controversy of fraud surround Uchemba afta one human right activist, Edafe Okoro share screenshot of how di child actor dey claim to be United Nations ambassador. Edafe Okoro claim say Uchemba request money from am to pay, so dat e go put am among delegation to United Nations youth event for US. According to di screenshot wey go viral on social media, Edafe alert di United Nations Youth Envoy, Ms Jayathma Wickramanayake wey later tweet say dem no get any representative for Nigeria. Uchemba deny di allegation from Edafe plus di claim wey say im dey pose as United Nations ambassador. E say na di handwork of pipo wey dey impersonate am for social media" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54957106 +politics Godwin Obaseki of Edo State fresh warning for Adams Oshiomhole, im & Shauibu collect INEC Certificate of Return as court set up Governorship Election Tribunal "Edo State Govnor, Godwin Obaseki don tok say im no get any plans to pursue di former National Chairmo of di All Progressives Congress, Adams Oshiomhole comot for di state. But say if Oshimhole continue to dey do wahala for state, im no go mercy for am. Obaseki wey win second term for office on Saturday, 19 September say Oshimhole dey try cause quarrel between di govnor and im opposition, Osagie Ize Iyamu. Obaseki wey be candidate of Nigeria main opposition Peoples Democratic Party, bin win im main opponent, Pastor Ize-Iyamu from di kontri ruling All Progressives Congress candidate wey get Oshiomhole backing. During di Morning Show for Arise TV on Tuesday, 22 September, Obaseki wey bin dey ansa kwesion about im threat during im election campaign to pursue Oshiomhole comot for Edo state, tok say, ""I no get any plan to pursue Oshiomhole from Edo but if im continue to dey do wahala, we no go show mercy."" Im say im no go wan tok too much about Oshiomhole, say dem don deceive di former APC national chairmo. Meanwhile, di Independent National Electoral Commission INEC don give certificate of return to Governor Godwin Obaseki and im running mate Phillip Shauibu di winners of di Edo State Governorship election wey hold on Saturday 19 September, 2020.Di INEC National Commissioner for Rivers, Bayelsa and Edo State May Agbamuche Mbu present di certificate to Obaseki and Shuaibu for INEC office for Benin, di Edo State capital. Also, di President of di Court of Appeal, Justice Mkica Dongban- Mensem don set up di Edo State Governorship Election Tribunal. Dis Tribunal go chook eye into any petition wey arise from dat election. Secretary of di Tribunal, Sunday Martins, for statement say di Tribunal get di mandate to hear and determine petitions wey fit arise from di election and dem go dey sit for di High Court Complex, Election Petition Court Hall, Sapele Road, Benin City, for venue wey di Chief Judge of Edo state, Justice Esther Amenaghawon Edigin go approve Im say di secretariat don open for di exercise and pipo wit any further inquiries fit ask di Secretary via 07010058493." https://www.bbc.com/pidgin/54252412 +entertainment BBNaija eviction: Big Brother organisers say Sunday go see housemates dey evicted on a 'king size' scale - See wetin e fit mean mean "Organizers of di Big Brother Naija 'Shine Ya Eye' reality TV show don tok say dis Sunday live eviction go be 'King-size Eviction'. Di organizers reveal dis one for dia social media platform as fans dey ginger to see who go leave di house on Sunday. Some fans and viewers of Big Brother Naija 'Shine Ya Eye' reality TV show fit no dey surprise to hear King-size eviction. Dis na because all di housemates dey up for possible eviction on Sunday except, Jackie B and Jay Paul wey be di Heads of House. Jakie B and Jaypaul win oda housemates on Monday to find di most keys and finish dia task for di weekly Head of House game on 30 August wey biggie introduce with a twist. Dis week HOH game bin come wit a twist as Biggie announce earlier say dem go get two winners and e tag am 'The double Heads of House'. So in total, na 15 housemates dey up for up for di possible eviction on Sunday and dem be; Tega, Saga, Saskay, Emmanuel, Peace, Boma, Nini, Michael, Cross, Angel, WhiteMoney, Liquorose, Pere, Queen and Yousef. Just as di name 'king-size' imply, e be like say na plenti housemates go leave on Sunday, although we no know how many as di organizers no tok di number. But last week Sunday, three housemates - Maria, Sammie and JMK chop eviction for a triple eviction show. So if biggie dey tok about king-size eviction next, e fit mean say more dan three housemates dey go home on Sunday be dat. Some social media users wey comment under di 'kingsize eviction' announcement wey big brother Naija organizers post, want make Boma, Nini, Peace, Saga and Tega comot. One user, Oluwademilade Eniola Gbolahan tok say; ""Whatever size e be weda King or Queen size. Please for di sake of humanity and mankind, do everything possible to oust Boma, Nini, Peace, Saga and di Aunty Tega of our time out of dat house tomorrow. We no get choice with Jackie B, we fit wait for am wait till next week."" Anoda pesin, Felicia Bukola say ""...those wey fit leave on Sunday na Tega, Boma, Saga, Nini, Peace and Michael. Odas say; ""Mr Ebuka, Dis is big brother, Evict saga, Boma and any oda pesin of ur choice, Or else na half money u go collect oo. Thank u"" ""My predictions na Saga, Nini, Boma,Tega and Peace..if dem dey up to six? Then sorry Michael ,you go leave..."" ""Big brother l know say you go evict Nini and Saga same day, but please Can you evict Nini first l wan to see Saga running after Nini Shouting Nini please wait for me."" ""Whatever size e wan be...Boma, Tega, Nini and peace should leave di big brothers house. I want to see saga wail in loneliness""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58446211 +politics Nigeria lawmakers troway Bill wey want six-years single term for President, Governors One Bill wey for see Presidents and Governors for Nigeria serve six-years for one term don fail to scale through second reading for di kontri House of Representatives. Di bill for also consider six-year term for Members of di National Assembly and States Houses of Assembly. Many members of di House of Representatives reject di bill wey John Dyegh from Benue State sponsor as di lawmakers vote against am. Oga Dyegh tok say di bill dey necessary for members of di National Assembly to collect more experience for di six years instead of four. Di lawmakers say instead wetin dem suppose look at na credible election process as six years fit no dey enough for President or governors to make any impact even if dem get di six year single term. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50825013 +entertainment Laycon BBNaija 2020 Winner: Olamilekan Agbeleshe win Big Brother Naija season 5 reality TV show - See wetin you need to know Laycon don win di big brother Naija season 5 reality TV show afta 10 weeks inside di lockdown house with 20 housemates wey participate for di show. E don be di 5th winner for di ogbonge show and join past winners like; Katung Aduwakwey win first edition for 2006, Efe Ejeba (2017), Miracle Ikechukwu (2018) and Mercy Eke (2019). Di winner of BBNaija season 5 go get di biggest prize ever, value at N85 million. Di breakdown of di grand prize include: Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos. E be graduate of philosophy from University of Lagos. E bin tok during di beginning of di show say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata. Laycon say one of e biggest achievement na im song 'Fierce' wey dey for MTV BASE Top ten charts for six months. Laycon get 60% of votes to beat di oda four hosemates wey bin dey top 5 position with am. https://www.bbc.com/pidgin/media-54316607 +sports World Cup qualifiers 2022: Predictions for Hungary vs England, Ghana vs Ethiopia and more "Di 2022 World Cup qualifiers for Europe and African resume again on September 1, 2021. And e go continue on Thursday wit some ogbonge fixtures for Europe and Africa. One of di main matches wey go shele go see England travel away to Hungary. Gareth Southgate say England must ""start again"" for di ""journey"" wey im hope go see dem build on dia performance for Euro 2020. Southgate team bin reach the final of di Euros for July, but lose for penalty shootout to Italy for Wembley. Dem go travel go Hungary on Thursday wit three wins out of three for di qualifiers for next year World Cup for Qatar. ""Di team don gain confidence from wetin dem don achieve and di progress dem don make,"" Southgate tok. ""Mentally na good test for us. Away from home, 60,000 fans and against a very good team. We gatz dey at our best."" Deji Faremi, wey be football sabi pesin tell BBC Pidgin say e not expect surprises like dat for di World Cup qualifying matches dem for Europe. But add say some small teams fit get one or two draws aside dat nothing else. See wetin im tok for di Hungary vs England match wey go kick-off 7:45pm (West African time) England na one of di most confident sides for Europe at di moment Deji tok But add say Hungary na good team wey go put up a good fight. Deji tok. Predictions England go win 3-1. Ghana need to take advantage of dia strong home form for competitive games and take a strong hold for dia qualifying group. Ethiopia na one of di teams dem go looking to collect points from. Predictions- Ghana go win 2-0 Di European champions dey mad form now. E dey very unlikely say Bulgaria go get luck for dis game based on dia recent records. Predictions- Italy go win 4-0. Dis na tough game. Di Spanish team don struggle recently to score goals and finish team patapata. I feel say we go get di same results from dis two teams, like when dem jam each oda for Euros 2020.di same result . I think we'll see a repeat of their result at the EUROS. Predictions -Sweden 1-1 Spain Germany go win dis match one. Dis na one of di games wey you no expect say dem go lose. Predictions- Germany win 2-0. Di ten group winners go qualify for di 2022 World Cup wey go run from 21 November to 18 December for Qatar. For di play-offs wey go happun between di 24 to 29 March 2022, di pipo wey carry second for each group go join di two best group winners from di 2020/21 UEFA Nations League. Dat na those for overall ranking wey no qualify directly for di final tournament as European Qualifiers group winners. Or enter di play-offs wit pipo wey carry second for di European Qualifiers group. Dem go draw di 12 teams into three play-off groups for knockout semi-finals and final match. Di three group winners go qualify for di World Cup." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58426989 +health Coronavirus: Ghana start dey work towards deployment of Covid-19 vaccines Ghanaian Prez Akufo-Addo set up committee wey go look into de deployment of safe Covid-19 vaccine for de country. He make dis announcement during en 20th Covid-19 address to Ghanaians. According to Prez Akufo-Addo, govment go ensure say de Covid-19 vaccines wey Ghana go deploy go be safe for citizens. He caution citizens say make dem continue to use nose mask den observe de Covid-19 safety protocols during de Christmas celebrations. De newly elected Ghanaian leader also commend de Electoral Commission of Ghana over how dem follow strict COVID-19 safety protocols during de just ended 2020 elections. Total Covid-19 infections for Fhana dey stand at 54,643 out of which 52,331 recover wey 331 people die of de virus. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55389667 +entertainment Nollywood actress Destiny Etiko: Film star reply comments for social media about how she buy her car "Nigeria Nollywood actress Destiny Etiko don reveal how she get her Prado SUV car afta tori begin fly up and down say na one married man give her di car as gift. For one Instagram live video on Monday di actress deny all di rumour about her new Prado car wey she just tear rubber. ""I love land cruiser, Prado, I buy am wit my money"". na wetin di Nollywood actress tok. ""I no even get time for myself, e no get day wey I no dey work and I dey make good money"". na wetin she add put. Dis na di second time wey di Nollywood actress Destiny dey address di mata about her car for social media .Tori be say for some days now na her gist full pipo mouth afta she post video of her new car for social media. Na so tori begin fly up and down say di car gift na one rich man dash her something wey she don constantly deny. She also tok about di man wey many pipo dey claim say dash her di car. ''Make una leave di innocent man alone oh, somebody wey I neva meet wey get beautiful family''. Destiny don act ova 20 Nollywood movies for Nigeria, one of dem na From Tears To Riches in 7 Days." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55998378 +entertainment BBNaija S6: Saskay, Yousef eviction make fans drag Angel, plus Monday nomination update "Fans of Big Brother Naija reality television show don react to Sunday eviction wey see Yousef and Sasky leave di Shine Ya House game. Tori be say five housemates bin dey up for possible eviction on Sunday dem be, Cross, Emmanuel, Yousef, Sakay and Angel. Di fans save Cross, Emmanuel and Angel. Yousef and Saskay na di fifteenth and sixteenth housemates to chop eviction dis season. Afta dem get di least amount of votes from di fans of di show. But some fans no dey happy say Angel avoid eviction yesterday. Na Yousef first comot from di house afta di host Ebuka Obi Uchendu tell am to leave di house As him join Ebuka on stage, Yousef say im no dey disappointed about im eviction. Rather im dey, grateful say im make to di house till dis moment. Im describe im stay for di game as ""just sliding through"" and add say e enjoy himself wella. For im future plans Yousef tell Ebuka say im dey look forward to endorsements and acting movies. Afta Yousef Saskay na di next to leave di house. Dis na wetin she tok about her eviction, she say she tire for di whole reality TV show experience She tell Ebuka say Jaypaul spoil her for di House and so she bin miss am wella wen him comot. Kelebogile Chauke say ""Bigbrother don teach me neva to trust pipo, una say Sasky and Yousef get big fanbase chai."" For Nayiga Mariam Ndibulungi e tok say ""di show dey scripted, una don dey save Saga now Angel but evict Maria. Hmm"" Meanwhile Kgothatso G Malwaeba say ""seeing di poll una wish say Biggie evict 3 pipo abi? E choke Angel stays."" While Ifunaya say ""Ojoro dey dis poll. Dem replace Sasky wit Angel."" Pat Amanda say ""who vote for Angel ."" Na nine housemates remain for di house to compete for di star prize of wey be ninety million naira (N90,000,000) for di one lucky housemate wey go win di show. On Monday 20 September 2021, na nomination and head of house games. Di housemates go nominate each oda for possible eviction on Sunday. Di housemates wey get di highest number of votes go dey up. While pesin wey win di head of house games go get automatic immunity from eviction. But Biggie fit change di game at anytime. Fans need to watch di nomination show to find out if him go introduce any new twist." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58612485 +sports Idrissa Gueye: Senegal midfielder go do medical with Paris St-Germain Senegal international Idrissa Gueye go do im medical with Paris St-Germain wey go clear road for di Everton midfielder to join di French Champions. Di 29-year-old join Everton from Aston Villa for £7m for 2016 and tori be say im dey leave for over £25m. Gueye don play 108 times for di Toffees for all competitions. Tori be say im show for Paris on Sunday and e suppose do im medical on Monday. Im be di second Everton player wey dey leave di club inside one week afta di club sell Ademola Lookman to RB Leipzig. Everton Manager Marco Silva don already sign midfielders Andre Gomes and Fabian Delph, as well as goalkeeper Jonas Lossl, but im say im hope to sign anoda five players before di transfer deadline on August 8. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49155105 +politics US election 2020 result: Ghana pastor curse critics who call am ‘fake pastor’ after US election victory for Donald Trump turn beans "Ghanaian prophet, Isaac Owusu Bempah dey unleash curses on people wey dey criticize say he be fake sake of en prediction say Donald Trump go win US elections no happen. En critics circulate video where de prophet predict say Donald Trump go win de US elections. However since de prophecy fail some start dey tag am as fake pastor, but de prophet say he never talk say Republican Presidential Candidate, Trump go win. ""If God who speak to me wey e no be from my own mind… I no steal, I no rape anyone. So if I say God show me something wey you dey speak against me, God go visit you,"" Isaac Owusu Bempah talk. ""That gentleman for airport who dey insult me, he go die miserable death, dem go suffer on earth before dem go die"" he add. De popular Ghanaian prophet who normally dey predict future happenings in 2019 enter hot soup after he claim say National Chief Imam for Ghana go die. Prophets for Ghana normally dey like predict who go win elections, which popular figure go die den tins. Sometimes dis dey land dem in trouble but when de prophecy happen, e dey help build dema reputation among Christians who dey believe in prophecy." https://www.bbc.com/pidgin/media-54907680 +health Burundi President Pierre Nkurunziza wife don comot for hospital for Kenya Denise Bucumi Nkurunziza wife of late president of Burundi don leave di hospital for Nairobi, Kenya just hours afta dem announce di death of her husband, Pierre Nkurunziza, on Tuesday afternoon. Dem fly Madam Nkurunziza, wey be 50 years, from Bujumbura to Nairobi on May 28th for sickness wey nobody know about. One official for Burundi president office don deny BBC tori wey say Madam Nkurunziza go Nairobi for coronavirus treatment. Anoda official for one private hospital wey bin admit say Madam Nkurunziza confirm to BBC say dem discharge Burundi first lady she leave on Tuesday evening, without giving details on her conditions. One private journalist for Bujumbura, Burundi, tell BBC Great Lakes say Madam Nkurunziza bin land di kontri on Tuesday night. Madam Nkurunziza, get five children and na former migration officer, dem no her for Burundi for charity foundation 'Buntu' and women empowerment campaigns. Burundi don begin seven days of mourning for di death of her husband. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53004528 +entertainment Coronavirus: 10 songs wey dey help di world with lockdown "As na almost half of di world don dey follow social distancing rules, many of us dey carry ourselves back to our favorite music dem for comfort. Dem dey help us to reflect, mourn and even rock bodi small as we dey follow dis social distancing rules. Na im make BBC Minute team wey dey provide news bulletin give radio stations around di world, ask those radio presenters di songs wey dem dey play for dia listeners for dis lockdown period. You sef fit use am as your lockdown playlist. Many Nigerians dey miss dia night hangout if you wan look di #BopDaddyChallenge. Ronke say di challenge dey trend for TikTok. Di song na just about man wey dey tok about imself, but ""di important tin be say na banger wey pipo fit jolly for house. "" Di challenge show pipo dey go from night cloth to beta evening kackup. Ronke laugh say, ""dem dey dress up and dem no dey go anywhere"". Billie Eilish sad song wey tok about nightmare wey she kill herself no be song wey go comot di lockdown blues but tori pesin Tebogo tok say na di music of di time on top how di pipo dey feel. ""Pipo for Botswana no know how e go be las las so dem no get choice but to dey hopeful. For di song Eilish find peace for di hands of her closest friends like her brother, Finneas. John Lennon popular song dey ask for unity and compassion. And Michael for Hong Kong Metro Plus tink say pipo don dey show demselves even more than Elise before. Like if pesin no get mask dem go give am no be about race or anything. E say, ""Human being now dey fight something wey dem no fit see (Coronavirus). If we all collabo togeda, we fit get through am. Asfandyar big palava na to create positive vibes for di pandemic. Im team come remix one traditional bop wey e say dey give pipo courage. ""E dey make dem feel like defenders, an army and na because dem dey stay for house dey keep demself and dia family safe."" Lockdown don make radio to turn essential more than ever for inside northern Uganda. Okeng dey use I'm show create love tori as e dey connect pipo for Im show. For dis lockdown, young lovers dey one love song by BeePee to take cope. Okeng say dis song mean, ""keep me for mind for good and bad times"". Even as pressure for internet don plenti for lockdown, di seven members of Dubioza Kolektiv dey video call and jam gbedu even as all of dem dey dia own house. For normal day Radio, Antena dey play English music well-well but now dem dey play part of dis group dem live jams. Naida explain say dis coronavirus era don make pipo dey crave more music from Bosnia artistes. ""Pipo dey hit us from all ova di world, dem wan hear music for we language and wetin we dey go through."" Dis song na from 1988 and na song wey pipo dey sing from dia houses for Spain. ""Na I go fight kind of song, no be I don win song"", according to Valeria. Cover wey plenti stars follow for 2020 don become dia most requested gbedu even though Uruguay neva get plenti coronavirus deaths. Valerie say, ""pipo dey fear as dem get family for America and Spain"". ""The stone that the builder refuse / Shall be the head cornerstone."" Maya love dis Bob Marley lyrics wella. She tok say di ragtag star turn from freedom symbol for 2019 when Sudan bin get political palava to father figure wey dey tell dem ""e go beta"" now wey be say di poorest communities dey hear, wen on top restriction. ""Na our anthem,"" na Wetin Moustafa tok about dis 70s banger. ""For dis radio station, anytime we dey feel down we dey say, we go rock dis no wahala. And na di same for our listeners cos anytime dem feel down, dem dey request dis song"". Moustafa say Radio don dey give young Iraqis escape from dia daily palava especially for dis lockdown and he say e dey gbadun am too, ""because as dem dey tell me dia wahala, me too dey gist dem my own. E dey awesome. "" E mean Our Home, dis gbedu don take new meaning for Jakarta Smart FM. As Presenter Hisa dey use am make pipo for stay house as dem no wan gree hear. ""Di song na about how Indonesia beta pass any wia wey you enta for world and for now, e no only good to dey di kontri but also to dey your house. "" No official video dey for di song." https://www.bbc.com/pidgin/world-52455818 +entertainment Ozo and Prince BBNaija: Why Big Brother Naija Head of House tell Prince 'shut up' as dem dey do drama rehearsal Ozo and Prince kwanta for Big Brother Naija house sake of to win dis week Wager Challenge. Di Housemates bin stay awake for night to practise dia music drama. Wit Trikytee as di producer and leader of dis task, di housemates gats wear dia acting masks wit some level of discipline and seriousness. As dem dey do rehearsal for dia music drama, Prince waka comot from di rest of di Housemates and Ozo no take am funny. For di first time, Ozo begin rake no be small. As Ozo dey shout. Prince just dey calm, so di quarrel no turn fight. Trikytee bin also step in to control di matter. E no reach one minute, Ozo calm down come tok sorry to di House unto say im lose im temper. Im also tell Prince sorry say im shout on am, while im dey explain to Prince say e dey disrespectful to di House as im walk out. Tho di quarrel no last for long, e shock pipo to see Ozo for dat kain mood. Now pipo don begin wonder weda di shouting na because Prince bin waka comot from di Housemates or weda Ozo dey vex say Prince dey close to Nengi - di babe wey im dey eye for di House. https://www.bbc.com/pidgin/53675359 +entertainment Chiwetalu Agu: Nollywood actor give account of im time for army and DSS custody "Ogbonge Nigeria Nollywood actor Chiwetalu Agu wey Nigeria security forces arrest for di first week of October, give account of wetin happun to am while im dey dia hand. Inside interview wey di Nollywood veteran do wit BBC Igbo, di actor say although di junior military men wey bin arrest am for Onitsha no treat am well, di senior officers plus di Department of Security Service (DSS) wey im later meet try well. Men of di Nigerian Army bin arrest Chiwetalu on October 8 for ""inciting members of di public and soliciting support for di proscribed Indigenous Pipo of Biafra (IPOB),"" sake of im wear shirt wey resemble dia flag. But di actor deny say wetin im wear no be Ipob flag but rising sun and rising sun don dey since Ojukwu time. ""Di tin wey important to me for dis my waka be say wetin dem write for my cloth na rising sun. Rising sun no be today tok, rising sun na since Ojukwu come out make we defend ourselves for Nigeria hand naim we don dey tok of rising sun."" Di actor tok about many tins wey concern di incident inside di interview wey we summarise here. Di sojas cari Chiwetalu from Onitsha hand am over to di intelligence officers for 82 Division of di Nigeria Army for Enugu. According to am, im face panel wey get plenty generals and dem question am for 9 to 10 hours. ""Dem hold dis fone, you know wetin be excavation… na so Nigeria soldier panel wey den set up for 82 Div take do (search my fone), dem no see anytin."" Oga Agu say afta di army finish wit am, dem send am go DSS, na dia tori get k-leg. E say dem no allow am sleep na so dem bundle am from Enugu go Abuja. ""Di treatment wey dem give me dia no be di best but dem try dia best."" E say although di DSS try dia best to give am di kain food wey im dey chop, but di food no come on time and hunger almost finish am becos im get ulcer. DSS also search im phone plus ask am plenty questions about everytin wey dey inside. Chiwetalu Agu say, im promise DSS say im go make one sacrifice and dat na to hide di cloth for archives. But say dat cloth no find any trouble. E add say di rising sun cloth na cloth wey be say ""if you see am e go give you strength, e go give you hope say beta go still happun."" ""Dat cloth no find any trouble. Di only time wey cloth go find wahala na wen you write IPBO, ESN, come wear am dey waka. Becos those tins dey intimidating."" Although di actor promise DSS to put di cloth for archives, im say afta di cloth don chill finish for archives, ""e get many oda styles wey I go cari come. ""E fit be say di next cloth wey I go wear go be white and rising sun"" so dat army no go tink say e wan fight wit dem. E also come add say dem go begin manufacture tins like matches and even motor wit rising sun. Di ogbonge actor say, im no see di proscribed Ipob leader Nnmadi Kanu, but im happy well-well wen im hear say di two of dem dey di same building. ""I no see am but di kain feeling I bin get wen dem tell me say, my room dey for down, Nnamdi Kanu dey for di room wey dey upstairs. ""I bin wan tell dem say before I leave dis place make una show me Nnamdi, even if you no allow us tok, but just make we hug, dat one don do me. But e get as tins take happun, na im I advise mysef."" E describe Nnamdi as ""icon for Igbo land,"" but add say wetin im no like na as violent pipo, bad pipo come join dem begin kee-kee in his name. Im say Nnmadi go be like ""Martin Luther King, e go be like hero… Mandela of South Africa."" Nigeria Army bin confam di arrest of di Nollywood actor on 8, October. According to statement from di army HQ, dem arrest am as im dey ginger members of di public to support di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB). Dem add say dem pick di actor wey wear di cloth attire of di proscribed group, for questioning and although im bin resist wen di troops make effort to take am into custody, dem say dem no assault or brutalise am. Na from army hand dem bin transport di actor to DSS custody." https://www.bbc.com/pidgin/58937813 +health Coronavirus update: African leaders collect vaccine live on TV, as countries begin roll out "Ghana president Nana Akufo-Addo don collect im kontri first dose of di Covid-19 vaccine on Monday, as sign of im leadership but im no be di first African leader to do dis. Many world leaders dey do dis as dia responsibility to spread confidence say di Covid-19 vaccines dey safe. For Nigeria, expectations na say President Muhammadu Buhari, go be di first pesin to collect di COVAX programme vaccine wey don land di kontri on Tuesday 2 March. Dr Faisal Shuaib, wey be di oga of di kontri National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) say di president go do dis live on TV to encourage Nigerians to take di vaccine. Even before im presidency dey official, di then US president-elect Joe Biden, on 21 December 2020, collect vaccine live on television to show im kontri pipo and di world say ""nothing dey to worry about"". Small time after, oda kontri leaders like Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu and Saudi Arabia Crown Prince Mohammed bin Salman begin. And African leaders no dey too far behind for dis 'live on air' vaccination. Make we see wia who don collect, which type dem collect and wia dia kontri dey wit dia vaccination plan. President Wavel Ramkalawan make history on 10 January 2021 when e become di first African leader to collect vaccine live for public. Di Seychelles president take di China-made Sinopharm to mark di start of dia kontri vaccination plan. For one of im kontri most poor township, President Cyril Ramaphosa on 17 February go di Khayelitsha Hospital - wey be public hospital - to collect im vaccine live on television. Dis way di president use one stone to kill two birds: E demonstrate say di Johnson & Johnson coronavirus vaccine safe and say e dey okay to enter public health facility to collect am. Ramaphosa later tweet say di vaccine injection ""dey quick, easy and e no dey pain"". Although no be di president collect di kontri first covid-19 vaccination, president Emmerson Mnangagwa on 18 February say ""thank you"" to deputy Constantino Chiwenga wey do di honours live on television. Chiwenga na also di kontri health minister. E no dey clear whether Mnangagwa collect privately later later. President Macky Sall collect di Sinopharm, for di presidential palace on 25 February. Although im no be di first kontri man to collect as di official roll out start two days earlier. King Mohammed VI mark im kontri vaccination program when on 28 February, e collect di first Covid-19 vaccine for di Royal Place. Di first category of pipo wey go dey vaccinated for di kontri na 75-year-old plus pipo, and health, security, and teaching staff. Di World Health Organisation don maintain say dem no allow companies take any shortcuts for di production of approved vaccines. For im nationwide address, Akufo-Addo rubbish rumours by some Ghanaians say di vaccines fit change pesin DNA and destroy di African race, Modern Ghana bin report." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56236357 +politics Appeal Court Judgement on APC national chairman: All Progressives Congress chop fresh court order from Victor Giadom Federal High Court for Abuja don reconfirm di position of Victor Giadom s di All Progressive Congress party acting national chairman. Di court on 18 June, 2020 uphold im March 14 decision to appoint di party deputy national secretary Victor Giadom, as di acting chairman. Di court don extend dis decision wey im bin make on di 16 of March for di period of two weeks. Justice Senchi Bature wey don dey hear di case since March 4, give order make make APC or any of im officers no prevent oga Giadom in any way from doing im work as acting national chairman, except na di national executive committee. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53099304 +entertainment Zainab Booth Kannywood: Maryam Booth confirm death of Hajiya Zainab Booth wey die at 61 years Kannywood actress Hajiya Zainab Booth don die for di age of 61 years afta long illness. Di veteran actress die for Kano on Thursday night, according to wetin her son, Umar Booth tell BBC during one interview. Her daughter, Maryam Booth also confam her death through one post for her Instagram account and add say dem go bury her mama on Friday. Zainab Booth na one of di first actresses wen Kannywood kick off for di 90s and she born four pikin. Among her children three na actors wey still dey very active for di industry, dem be; Maryam Booth, Ramadan Booth and Amude Booth. During Zainab Booth career, many pipo for di acting industry dey refer to her as 'mama' including high profile actor Ali Nuhu wey also announce her death for im social media profiles. One of her recent popular films na 'Mai Nasibi' wey she act alongside Rabiu Rikadawa and play di role of wife to one fraudster. She bin dey sick for sometime and one of her pikin recently tok about operation wey she do for hospital. Sympathizers rush go her house wey dey for Court Road for Kano afta dem hear tori of her death. Hajiya Zainab Musa Booth leave behind four children and two grandchildren. Plenti Kannywood stars and fans don already begin to mourn di death of Hajiya Zainab Booth. Stars, producers and oda ogbonge pipo like Ali Nuhu, Falalu Dorayi and Aminu Saira pray for her well-being. For one message wey Aminu Saira post for im Instagram page, e pray for Allah to forgive Hajiya Zainab Booth 'short comings.' Odas too like Saratu Gidado Daso don express shock and send dia condolences to di family of Hajiya Zainab Booth. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57698898 +sports Geleta Ulfata: Meet di Ethiopian wey win di 7th edition of di Lagos City Marathon Geleta Ulfata of Ethiopia don win di 7th edition of di Lagos City Marathon. Ulfata don claim di grand prize of $30,000 im win di 42km race on Saturday, February 12. Im finish di race in two hours 11 minutes and 54 seconds. Di Ethiopian athlete beat 300 marathoners to win di race wey dem start at di entrance of di National Stadium, Surulere. Eko Atlantic City, Ahmadu Bello Way, Victoria Island, na dia be di finish point and Ulfata reach dia before all im opponents. David Barmasai from Kenya naim finish second while Emmanuel Naibei wey also come from Kenya win di third position. Barmasai finish di race in two hours 13 minutes and 33 seconds. Im don collect $20,000 while Naibei go return to im kontri wit $15,000. Dagne Siranesh Yirga from Ethiopia na she be di first woman to cross di finish line at two hours 33 minutes and 50 seconds. Another Ethiopian woman Alemenseh Guta na di second woman to cross di finish line while di third na Naomi Maiyo from Kenya. Before di Marathon happun today, Lagos State goment bin divert traffic and close some roads in di state sake of di competition. Motorists from Eko Bridge wey dey come from Apongbon to Costain Roundabout bin connect to Ebute-Metta, Orile, Nigeria Breweries, Abebe Village, Eric Moore, Bode Thomas, Adeniran Ogunsanya to link to dia destinations. Na Barmasai win di 5th edition of di competition wey happun on Saturday, February 8, 2020. Di Kenyan man bin complete di race in two hours 10mins 22 seconds, and claim di grand prize of $50,000. Naibei nai win di 6th edition of di Lagos City Marathon. Na two hours 11 minutes and 37 seconds Oga Naibei take finish di race to claim di grand prize of $30,000. https://www.bbc.com/pidgin/tori-60358749 +politics House of Reps order to shutdown Edo State Assembly na academic exercise - Francis Okiye "Speaker of Edo State House of Assembly for Nigeria Francis Okiye, don reject di Nigeria House of Representatives call for di Inspector General of police and Department of State Security to shut down di assembly. Okiye tell BBC Pidgin say di order na academic exercise wey dey cosmetic and e no get support from any force of law for Nigeria."" Di request follow di report of di House ad-hoc committee wey dem set up to investigate the crisis wey dey mama di state assembly. Kasala burst afta nine out of 24 members sideline 15 odas to elect Speaker plus oda principal officers for Edo State House of Assembly. But Okiye say ""crises suppose dey ground before di National Assembly go begin explore Section 11 subsection 4 and 5, and di constitution define di kain crises wey e mean wey be say di House no go fit perform im functions again and dis no be di case for Edo State as di House dey seat,"" ""Dem dey clear Commissioners and dem dey di second reading of one bill wey di Executive give to dem and dem dey carry out dia oversight functions so e no make sense for any body to say di House no fit perform dia functions."" Okiye tok. Di Speaker add say all di parties wey dey involved for di mata dey court. ""As e dey for di National Assembly, Order 9 Rule 6 preclude di National Assembly not to discuss any mata wey already dey for court as e go be subjudice and for di State House of Assembly na di same tin."" Di Speaker come add say for all di tins, e show say ""some pesins dey play di beat of outside drum beaters and e dey very unfortunate to democracy. ""Besides na National Assembly affair, no be House of Reps affair. National Assembly compose of di Senate and House of Reps so no be duty of House of Reps to pronounce order wey instruct di Inspector General of Police and Director of DSS to close down an institution wey dey constitutionally provided and protected to make laws"" Na so Okiye tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49022244 +politics Kano govnor aide wey share donkey say na wetin im pipo ask for "Di senior special assistant to Kano state govnor on youth development Murtala Gwarmai tell BBC say di reason e share donkey to some pipo for empowerment event wey e do three days ago na because say na wetin di pipo ask for. Gwarmai wey tok say dem go anoda empowerment event in two months time follow tok say even di donkey sellers association wey dey Kano personally come thank am afta wetin e do. ""Di reason why i share donkey dey simple, e get pipo wey even before elections meet me say dia own ambition na to be donkey owner, if dem get am, dem dey ok."" ""Dis na pipo wey dia work na donkey dem need - to transport things from farm and oda things."" According to am, no be just donkeys dem share dem follow share cement blocks, bicycles and even motorcycles. Sani Musa wey attend di event say di empowerment na good thing and e happen for time wey plenti pipo dey struggle. ""I attend di event but i no get anything but I get hope say wen di next one shele, I go dey lucky""." https://www.bbc.com/pidgin/media-54942880 +politics Osaremen Okolo: US President-elect Joe Biden appoint 26 year old Nigerian - American Osaremen Okolo as im Covid-19 Policy Advisor - See who she be "US President Joe-Biden don appoint Nigerian - American Osaremen Okolo as member of im Covid- 19 Response Team. Di daughter of di Nigerian immigrants go serve as Covid-19 Policy Advisor to oga Biden. Di Biden - Harris Transition Team wey give di announcement on Wednesday name her alongside other 100 pipo wey go dey work as staff for di White House. Osaremen Okolo bin serve on di Biden-Harris Transition domestic team before her new appointment. Okolo papa and mama na from Edo state, South-South Nigeria. Dem born and raise her for Massachusetts and dem born her for 1994. Di 26 year old graduate wit honours from Harvard University for 2017 wit degrees for medicine and African-American studies. She dey work as Senior Health Policy Advisor for di US House of Representatives. Before now, Okolo bin serve as Legislative Aide for Health Policy on di U.S. Senate Committee on Health, Education, Labour, and Pensions (HELP) for Ranking Member Patty Murray of Washington. She also work for U.S. Representative Jan Schakowsky of Illinois as legislative aide for health policy advisor. Her work dat time na to draft, negotiate and manage di Congresswoman legislation, oversight, and policy wey concern comprehensive health care and public health agenda. Recently, she focus only on di Covid-19 pandemic. Biden wey dey take over office on January 20, bin also name Nigerian-born Adewale Adeyemo as di Deputy Treasury Secretary. According to Biden and Vice President-elect Kamala Harris, di COVID-19 Response Team go ""work to quickly implement a comprehensive, whole-of-government COVID-19 response strategy to contain di pandemic, restore public trust, and protect all Americans""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55501525 +entertainment Tonto Dikeh: Nigeria Christian Pilgrim Commission deny Tonto Dike claim say she be dia 'Ambassador of Peace' "Nigeria Christian Pilgrim Commission don release statement to deny accuse say dem make Tonto Dike dia Ambassador of Peace. Di Nigeria Christian Pilgrim Commission say di claim by Tonto Dike say she be dia Ambassador of peace no follow. ""Dis claim by her dey spurious, unfounded and should be discarded and seen by all Nigerians as a figment of her imagination ."" NCPC tok. Nigerians bin dey criticise di Nigeria Christian Pilgrim Commision afta di Nigerian actress post pictures of her in meeting wit di commission for her Instagram page. She caption di foto ""I NOW BE PROUD NIGERIA CHRISTIAN PILGRIM COMMISSION(NCPC) AMBASSADOR FOR PEACE BUILDING...."" Di commission say di Nigerian actress bin visit dia Executive Secretary to tok on partnership deals. ""King Tonto Dikeh pay courtesy visit to di Nigeria Christian Pilgrim Commission, Rev Yakubu Pam for our corporate headquarters for Abuja. As di founder of Tonto Dikeh Foundation, she express her willingness and interest to partner wit di Commission in di area of peace building. She also cash in on di visit to commend di NCPC boss for im positive and relentless peace initiatives across di kontri."" , Di commission tok for inside statement. Dem make am clear say di Executive Secretary of NCPC neva appoint King Tonto Dikeh as Ambassador of Peace for NCPC and dis no even dey part of her visit. Dem describe reports from local media as clear misrepresentation. However dem salute Tonto Dikeh desire to partner with dem for dia our peace building initiatives and for di area of pilgrimage sponsorship to di Holy Land. Meanwhile di Nigerian actress don react to di latest statement from di commission say she no lie. ""E get video proofs, but I go rather respect di commission decision and take di Fall."", she tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56221149 +entertainment Big Brother Naija 2021 housemates profile and names: Meet di Female members inside season 6 'shine ya eye' house "Big brother Naija do di second leg of di show launch to introduce di female housemates on Sunday.Na 11 girls join di show wey already get 11 male housemates from di first leg of di launch on Saturday night. Di male housemates don already spend one day for the show. According to di host, Ebuka Obi-Uchendu, di show go last for 10 weeks. Di reality show go follow di lives of di housemates as dem interact and compete wit each oda to win di grand prize of N90million worth of prizes, wey be di biggest reward for any reality show for di continent. Angel Smith She be 21 years old from Akwa Ibom state. She say she be fun pesin wey promise to be entertaining for di house. She also claim say she dey bossy and she go dey real for di house. Peace Ogo She be 26 year old from Rivers state.Her hobby na to relax.She say she be nice pesin wey also claim say she go keep am real for di house all through the competition. Jackie B 29 year old from Adamawa state. She be single mother of a son and she say she come from a family of 12. ""You respect me I respect you"" na her watchword. She say she love music, dancing and having fun. Tega Tega come from Cross Rivers State. She say she get personality of water and fire and she say she no like make pipo no dey real. She don audition to be on Big Brother Naija plenti times before dem finally pick her for di 2021 season. Arinola Olowoporoku She be 29 years old. Arin na Fashion designer, she say she dey hardworking. She say she love to read and she promise to dey bubbly for di house. Arinola disclose say she get 17 piercing for her body. She bin start her career as Art producer but now she be Art Curator. Roselyn AKA liquorose She be 26 years old from Edo State. She be popular Nigerian dancer. She saye she don dey dance since she be 12 years old. Roselyn say she dey bring her playful self to di competition. Maria Nkechiyenre She be 29 years old from Imo State. She say she be lovely pesin and promise to entertain. Maria na realtor wet dey sell houses for Dubai. After di show, she say she go try venture into business for Nigeria. Maria dey single and hope to explore dating opportunities for di house. Beatrice Beatrice na fashion model wey come Port Harcourt, Rivers State. She also get clothing brand and afta di show she dey plan to improve on am and build a modelling agency She love to dance and she say she dey come di house wit lots of entertainment. Beatrice dey single. Princess Francis She be 30 years old from Imo state. Princess na Taxi Driver. Her hobby na cooking. And she say she dey bring all her energy into di show. ""Expect to go on a ride wit me"", she tok. Saskay 21 year old from Adamawa State. She say she be peace loving pesin and she say she be emotional pesin. Sakay na Artiste and Model. She say she go like own her own Art gallery afta di show. Saskay dey in a relationship. Anita AKA Nini She be 26 years old from Edo State. She say she go always dey ontop of her game all through di show. Anita get fashion brand and she also be model. She dey plan to officially open her fashion brand afta di show. BBNaija na di biggest reality show for Africa, ova 49 kontries for di continent na im dem estimate to tune in to watch di season launch according to di show organizers. For dis year show, organizers say dem cancel all audiences for live shows and evictions, dem add say di presenter go host di Sunday Live Eviction Shows for empty studio, crossing live into di Big Brother House." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57963017 +health Cameroon news: Hospital di chase victim wey no fit pay bills afta Yaoundé Rond Point Damas explosion "Kontri pipo don forget say local bomb bi explode for Rond Point Damas, (Damas Junction) for Yaoundé-Cameroon, life don turn to normal, pipo di buy and sell for de explosion spot. For July 2, local bomb, (pressure pot wit eight and six-inches iron rod weh deh bi tie'am for motorcycle battery) bi explode wound five pipo. One pesin weh de explosion remain for e mind and skin na Nke Prisca, mami for seven pikin, victim weh fire from de explosion burn. ""Dat day, we no bi see or suspect any tin, ah bi di sell plum and bobolo, de bomb dey for ma back. ""Pesin weh e bi wan buy bi stand for ma front, as ah give e plums di wan take moni, ah only hear na explosion, 'kpooo'"". ""Ah bi first check say na electric pole catch fire, ah hide wan hide under table, ah see fire for ma clothes, na dat taim ah dive for ground, all man bi di fall for ground and even de man weh e bi wan buy plum"". Dis explosion bin bi na three, afta de first two for Melen and Emana inside two weeks for Yaoundé weh e put capital city under security alert. Na so deh bi take Prisca go hospital, for wusai e don make three weeks. ""De first days for hospital no bi easy, deh di tie me napkin laik small pikin, na ma massa and ma mami di carri me up for ease ma sef"". ""Den, deh take me for theatre clean ma skin weh e bi just di high, afta deh clean de wound wit salt solution, put pomade"", Prisca tok. Na Prisca e mother-in-law kam take e grand pikin dem go village, e massa and mami di look-out yi for hospital. ""Dis accident don worry me, school go start, ah nova get moni for komot for hospital, no moni for send pikin dem for school"", Prisca di worry. Ah bi di find moni for ma pikin dem, make deh get chop, no tief, but see me today, Prisca add. Hospital di drive victim as e no fit pay bill Since weh Police bi kam leave me for emergency unit for Central hospital here, na all dat, Prisca tok. Good heart pipo helep and family try for pay for treatment, as for three weeks we don spend $ 364 (FCFA 200,000). Hospital discharge Prisca, but e get for pay FCFA 115,000 bill weh e remain for total $533 (315,000) before e komot. Ah just dey for hospital, deh no di give me any oda treatment again. ""If you no komot, we go give you anoda bill. Afta 10 days you go pay $39 (FCFA 22,000), also, you get for komot as we need bed for put anoda patient"", Prisca tori weti nurse tell e. Prisca e massa don go for social affairs unit, meet-up director for hospital, Prof. Fouda, but help no dey." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53538731 +sports Cameroon vs Ivory Coast live stream: Toko Ekambi give Indomitable Lions 1-0 victory over Elephants Cameroon don qualify for di playoff round to reach Qatar 2022 World Cup. Karl Toko Ekambi first half goal na im help di Indomitable Lions to important victory over Ivory Coast wey bin dey top di group. Ekambi control pass from Martin Hongla before im waya shot wey beat di goalkeeper. Cameroon dominate di match but bin really need di win to ensure say dem dey part of di 10 teams wey make di playoff round. Dis go be di second straight World Cup wey Ivory Coast no go qualify for. Dem go need ask demsefs some questions as dem top di group all through before dis last group match with Cameroon. Wit di victory, Cameroon finish top of di group wit 15 points wile Ivory Coast get 13 points. Di win see Cameroon join Senegal, Algeria, Egypt, Mali, Ghana, Morocco, Nigeria, Tunisia and DR Congo as kontris wey qualify for di playoff round. Na only five of dis teams out of ten go qualify for Qatar 2022 World Cup. Di teams don sing dia national anthems finish and don dey set for kickoff. 1min - Di host take di first touch as dis crucial qualifier don start. 3mins - Cameroon Leftback Nouhou Tolo don pick up injury and no go fit continue. 5mins - Ivory Cpast win freekick just outside di area as Cameroon foul Gradel. 6mins - Olivier Mbaizo don replace Tolo. Meanwhile Gradel kick di freekick go over. 11mins - Di hosts don begin enjoy good amount of possession but never create clear-cut chance yet. 15mins - Good buildup play see Aboubakar shoot weak shot wey im no hit well. Easy catch for Gbohoou. 21mins - Goal!!! Karl Toko-Ekambi give Cameroon di lead. Di Lyon forward control Martin Hongla pass before im fire di shot past Gbohouo inside di 18-yard box. 32mins - Zambo Anguissa foul Gradel just close to di corner flag. Seri to take, Boly head di cross over. 33mins - Save! Onana deny Frank Kessie from close range. 34mins - Yellow card! Cameroon hope to start counter-attack but Seri bring down Aboubakar. 40mins - Save! Aboubakar test Gbohouo from outside di box. Di goalkeeper push am go out for corner wey dem later clear. 45mins - Zambo Anguissa head cornerkick well wide. Cameroon still look comfortable so far as dem lead 1-0. 45+1min - Hongla spin loose im marker come pass give Ngamaleu wey bin dey 1-on-1 wit Bailly, di defender block im shot. From di corner Gbohuo clear di ball. Half Time - Cameroon 1-0 Ivory Coast. As e stand na Cameroon go top di group. Ivory Coast make change, Ibrahim Sangare enter for Odilon Koussounou. 53mins - Onana replace Hongla for Cameroon. Still 1-0. 58mins - Referee give Mbaizo yellow car togeda wit Frank Boli. 60mins - As e stand wit Cameroon lead, Ivory Coast go miss out from Qatar 2022. 69mins - Ivory Coast make two substitutions; Seri and Kouassi OFF, Pepe and Traore ON 71mins - Ekambi, Ngamaleu and Aboubakar leave di pitch, Choup-Moting, Lea Siliki and Tawamba enter. 81mins - Cameroon try to break quickly, Choupo-Moting try to chip Gbohouo but e go over. 83mins - Another change for Ivory Coast: Christian Kouame come on for Gradel. 85mins - Kessie connect wit Pepe cross, Onana catch im header am well. 89mins - Home fans for di Ahmadou Ahidjo stadium for Yaoundé don begin celebrate, just one minute before injury time. Referee add four extra minutes. 90+2mins - Chance! Kouame blast half chance ova di Yaoundé sky. 90+3mins - Cameroon goalkeepr Onana collect yellow card for time wasting. 90+4mins Last chance for Ivory Coast, Pepe to take corner wey even di goalkeeper rush come to no but Cameroon clear am. Di referee blow di final whistle. Cameroon progress, Ivory Coast crash out and go miss dia second straight World Cup. E finish Cameroon 1-0 Ivory Coast. Cameroon lineup: 23. Onana, 19. Fai, 22. Onguene, 3. Moumi Ngamaleu, 5. Ngadeu-Ngadjui, 4. Tolo, 14. Gouet, 18. Hongla, 8. Anguissa, 7. Toko Ekambi, 10. Aboubakar. Ivory Coast lineup: 16. Gbohouo, 7. Kossounou, 21. Bailly, 6. Boly, 17. Aurier, 8. Kessie, 4. Seri, 11. Cornet, 10. Kouassi, 22. Haller, 15. Gradel. https://www.bbc.com/pidgin/media-59310468 +business Jeff Bezos net worth 2020 as billionaire, American business magnate and Amazon.com CEO break stock record in one single day for Bloomberg World's Billionaires ranked list history Jeff Bezos add $13 billion to im net worth on Monday, dia na di largest single-day jump for any individual since dem create di Bloomberg Billionaires Index for 2012. Amazon.com Inc. shares go up by 7.9%, di highest since December 2018 since di trend of internet shopping increase and e don go up by 73% dis year, Bloomberg dey report. Bezos, di 56-year-old founder of Amazon and di world richest pesin, don see im fortune rise by $74 billion in 2020 to $189.3 billion, even as di US dey enta im worst economic downturn since di Great Depression. Personally, Jeff Bezos don rich pass di market value of giants like Exxon Mobil Corp., Nike Inc. and McDonald's Corp. Mackenzie Bezos, im ex-wife, gain $4.6 billion Monday and she go be di13th-richest pesin for di world. Oda tech titans dey also enjoy some increase sake of lockdown, as pipo dey forced to stay for house and shop online, dis don help di boost Facebook Inc. Chief Executive Officer Mark Zuckerberg don also add almost $15 billion to im net worth so far dis year, even as di company dey deal wit brands wey dey boycotting ads on di social network. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53482842 +politics Ghana Council of State election results update: ET Mensah go rep Greater Accra, Mahmoud Tahiru to rep Northern Region - Follow EC latest results here "Ghana Council of State election results for regional representatives wey go join President Nana Akufo-Addo appointees don begin come out, according to Electoral Commission [EC]. Ghana EC don declare Enoch Teye Mensah, wey be former Mayor of Greater Accra Region as di Council of State Member for di Greater Accra Region. Na George Kwame Amoah, Greater Accra Regional Director of Electoral Commission, declare am winner. ET Mensah na candidate of di main oppositino National Democratic Congress [NDC] wey contest against President Akufo-Addo New Patriotic Party [NPP] candidate. Di election office organise council of state elections nationwide to elect members on Friday 12 February, 2021 for different regions for di kontri. Mahmoud Tahiru Zunglana, a 61 year old retired Colonel win election as Council of State member for di Northern Region. Di retired Colonel polled 23 votes to beat three others who contest di position in di region. Northern Regional Director of di Electoral Commission, Lucas Yiryel supervise di elections. Refresh dis page for more results wey Electoral Commission declare For Ghana di council of state na small group of important citizens wey dey advise di President on national issues. according to 1992 constitution for di kontri. Dis election dey come few weeks afta di kontri December 7 general election wey elect President Nana Akufo Addo for office for second term. Di Council of State go include one former Chief Justice of Ghana, a former Chief of Defence Staff and a former Inspector General of Police and di President of di National House of Chiefs. Each region of Ghana also get elected representative. Di President of Ghana go also appoints eleven members. Di members go stay for office until di term of office of di president end. Di Council of State dey play major role to play for di governance of di kontri. According to di 1992 constitution for di kontri. (Chapter 9, Article 89) dia work na to ""counsel di President in di performance of im duties"" Na advisory role, especially when e gatz do wit difficult decisions or when crisis dey ground dem dey use wisdom to resolve di mata." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56043107 +sports NPFL Wikki Tourist FC bus accident: See how Wikki Tourist FC players, officials take escape death as dia bus burn to ashes Nigeria Premier League Club, Wikki Tourists FC players escape death as dia bus catch fire and burn to ashes for Hawan Kibo road, along Jos - Abuja road. Di club media wey give di informate for dia official Facebook page say nobody die for di accident. According to reports, di accident happun early hours of Thursday morning as dem dey travel go Uyo, Akwa Ibom capital for di day 11 of di Nigeria Professional Football League match. Di team dem dey play against na Dakkada FC, . Wikki Tourists Football Club na Nigerian football club wey dey based for Bauchi state. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56111784 +sports Champions League: Real Madrid vs Chelsea, PSG vs Manchester City semi-final match predictions "Two of Europe most popular clubs go meet for di first time since 1998 as Real Madrid welcome Chelsea for di first leg of their semi-final. Real Madrid and Chelsea don enjoy plenty success for Uefa Champions League although dis na Madrid first appearance in di last four since 2018 wen dem win dia 13th European Cup. Chelsea last reach di semi-finals for 2014, when Real Madrid neighbours Atlético, knock dem out of di competition. Meanwhile for di second semi-final Paris Saint-Germain and Manchester City, two clubs wey dey hope to win dia first Uefa Champions League title. Di first leg of dis ogbonge match between PSG and Man City go happun on Wednesday April 27 for Parc des Princes for Paris France. Even though di two clubs don enjoy plenty of domestic success in recent years, both of dem neva taste success for Europe. PSG beat defending champions Bayern Munich to progress, while City knock out Borussia Dortmund last season final for di first time only to lose to Bayern Munich. BBC Pidgin follow Deji Faremi wey be sabi pein for football tok about di Tuesday and Wednesday champions league semi-final matches. Deji share im thought on the four teams wey remain for di biggest club competition for Europe. Real Madrid and Chelsea na teams wey no too dey score plenty goals. na so Deji tok ""Di way I dey see dat game goals no go plenty dia. Di team wey go make di least mistakes, especially for defence go carry di day."" My prediction- Real Madrid go win di first leg 2-1. Last six games: DWDDWW Latest outing: Real Madrid 0-0 Real Betis, 24/04 Where dem stand: 2nd for Liga Last six games: WDWLWW Latest outing: West Ham 0-1 Chelsea, 24/04 Where dem stand: 4th for Premier League, FA Cup final ""I feel say PSG go use di advantage wey dem get for dia attack. Neymar and Mbappe help them beat Bayern Munich, and now di club go rely on di two players ability to make tins difficult for Manchester City."" E add say Off late City side dey struggle to score goals. My prediction-PSG go win di first leg 3-1. Last six games: WWWLWW Latest outing: Metz 1-3 Paris, 24/04 Where dem stand: 2nd for Ligue 1, French Cup semi-finals Last six games: WWLWLW Latest outing: Man. City 1-0 Tottenham, 25/04 (League Cup final) Where dem stand: 1st for Premier League, League Cup winners" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56891800 +entertainment Naira Marley Koleyewon: Naira Marley Chi Chi na 'love song and street vibes' for Marlians "Nigeria controversial musician, Naira Marley don drop two gbedu, back to back as part of im end of di year music new release. E call di two songs wey drop for midnight of Friday 11, December, Koleyewon and Chi Chi. Dis go make am a total of seven singles wey Naira Marley don put out for 2020. And na so pipo for inside social media don dey feel di new vibes wey dem describe as Naira Marley in ""new dimension"". While Koleyewon follow di usual vibes and street survival message wey Naira Marley like to dey put out, Chi Chi na love song wey many pipo bin no expect and fit even put e fan base, Marlians for proposal mood. Tori be say di gbedu, Koleyewon cari plenti swear words for inside but discuss basic parti life wey pipo go fit relate to. Known for e controversial and x-rated songs, Naira Marley recently collect nomination from popular Nigerian award for music, di Headies, as dem list e song, Mafo for Best Street-Hop Artiste. You go remember say Headies only just recently add Naira Marley for dia nominations list afta dem comot am from dia 2019 awards. For 2019, Headies snub am say dem get moral code by which dem dey take judge music wey dem dey nominate." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55277019 +entertainment Bridgerton Season 2: Regé-Jean Page, di 'Duke of Hastings' no go show for di Netflix series next chapter - See wetin di actor tok "Bridgerton actor, Rege Jean Sean, don announce im exit from di popular Netflix series on Friday. For im Instagram page, im share a very short post wey im title , ""Di ride of a life time."" ""Na absolute pleasure and privilege to be your Duke. to join dis family - no be just on screen, but off screen too. Our incredibly creative and generous cast, crew, outstanding fans - e dey all beyond anything wetin I fit have imagine. Di love dey real and go just keep growing."" E tok. Bridegerton on Netflix also confam di exit of Rege-jean Page , wey play di role of Simon, di Duke of Hastings for di feem. ""We go miss Simon presence on screen"", dem tok. ""Daphne go remain a devoted wife and Sister, she go help her brother navigate di upcoming social season and wetin e get to offer. All eyes go turn to Lord Anthony Bridgerton quest to find a Viscountess."" di feem join-body give hint on wetin go be di focus of di next season. Di Netflix latest drama trend as number one for Nigeria for more dan two weeks, some say because of di 'fine' actor Regé-Jean Page wey dem use as di star actor for di movie. Page, play di role of Simon Basset, Duke of Hastings for di movie. Simon na di Duke of Hastings wey swear say im no go marry. Dis no be di first film wey Regé-Jean Pagee don act, but dis one sweet pipo belle sotey dem begin wonder who be dis guy wey handsome like dis?" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56619246 +business Twitter pick Ghana as first Africa office - See wetin to know "US-based social media company Twitter don choose Ghana as di location of dia new office - di first wey dem go get ontop di continent. But wetin make dem choose Ghana? On Monday, Jack Dorsey tweet: ""Twitter don land di continent. Thank you Ghana and @NAkufoAddo"", to announce di first company office wey dem go set up Africa. De fact say di oga patapata of Twitter, wey bin visit Ghana for November 2019, thank president Nana Akufo Addo, show say dis na arrangement wey go get Ghana goment backing. Na also during di period of di Ghana visit na im Dorsey - wey bin dey do tour of African countries den - tweet im desire to come live on di continent for ""3-6 months mid 2020"" but say im no sure wia. But now e be like say im don make im decision, wit di announcement of Twitter new office. Di opportunity for Dorsey to live, share and contribute directly to Africa tech community, even if na from Ghana, na one wey many pipo for di industry no go joke with. From dia vacancy page, we torchlight say na nine positions dem dey find staff for. Visit dia website for more informate. De announcement receive chaw reactions including one from Ghanaian leader, Nana Akufo-Addo who describe de move as ""excellent.""He tweet, ""de choice of Ghana as HQ for Twitter Africa operations be EXCELLENT news. Gov't den Ghanaians welcome very dis announcement and de confidence dem get in our country"" E fit be because of how Ghana dey support business. World Bank say di ease of doing business for Ghana na 118, according to data wey dem release for 2019. Compare dis to di rank of 131 wey dia neighbour kontri Nigeria get. To avoid confusion, di rank of 1 mean say e dey easy to do business for that kontri. So in dis case Nigeria worse pass Ghana. But according to di social media giant, dem choose to put office for Ghana because na kontri wey dey do well for democracy and also support ""free speech, online freedom, and di open Internet, wey Twitter na advocate for."" E no dey clear if Twitter consider recent record of Ghana ontop mata wey relate to LGBTQI+, wey some pipo go say get small k-leg. Twitter also list dis oda reasons like how Ghana go host di Secretariat of di African Continental Free Trade Area. De social media giant get 32 offices for 19 countries. Ghanaians on social media dey create humour around de decision of Twitter to set up Headquarters of Africa operations for de country.Moments after de announcement by Jack Dorsey, dem take to same Twitter to declare say de reason for de move be sake of Ghana get better jollof pass some people.More people make excited over de news, most people believe say dis be solid opportunity for de country in de tech space." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56721937 +entertainment Wizkid Happy 1st of March greeting dey make Twitter shake "August or March? 1st of March or 24th August? Dat na di kwesion some fans of Nigerian afrobeats musician, Wizkid, dey debate for Twitter afta di star show face for di social media site. Wizkid bin tweet for January say im dey take break and promise to return by March: But March come go, im no show face. April, May, June, July; starboy still no appear for di site. So you go imagine fans surprise wen on 24 August, di musician post im first tweet since January. ""Elo Elo!! How tings tings ❤️"": E come follow dat tweet wit ""Happy 1st of March 😁"": Wizzy post don make im fans react, as some of dem no fit hide how belle sweet dem. Dis fan cry say im ""man"" don return: Some fans agree wit Wizkid as dem declare di day 1st of March:" https://www.bbc.com/pidgin/tori-49460278 +entertainment Joeboy New Album: Wetin we know about Somewhere Between Beauty and Magic "Joe boy don drop im first studio album, Somewhere Between Beauty and Magic on Thursday, 4th February. E go be im first full bodi of work since im EP wey im bring call am Love & Light. Joeboy post to thank im fans as dem hype di album as e comot. Di 14 track album no feature any oda artists and follow im normal M.O of im songs wey normally dey short but tori be say di songs average long pass im EP. Many pipo don dey gbadun di song for inside social media, as one pesin to say di reason why im no call di song ""Somewhere Between Beauty and Pure Juju"" im no go too cast. E bin reveal wen im drop tracklist for di begining of February say, ""To create records dem wey dey live changing na one of life's greatest gifts to humanity, and I don live inside di music sotay "" Plenti pipo don gbadun di song for inside social media sotay e start to dey trend for inside social media. Some pipo don either pick ""Door"" or ""Show Me"" as dia favourite song for di album. While odas dey tok about im bin no feature for im album. Joeboy, na di first artist wey comot from emPawa Africa and for 2019, release di visualizer for im first hit wey im call ""Baby"". Di 23 year old come drop im EP dat same year wey im call Love & Light wey feature songs like Beginning, Don't Call Me Back and All For You. Joeboy bin tease say im go drop im first studio album by 2020 but im postpone am. For 2019, im bin also reveal for BBC Pidgin QTMPY say im bin already get babe." https://www.bbc.com/pidgin/media-55915077 +entertainment Sammie Okposo news: Nigerian gospel artiste openly apologise to im wife Ozioma for infidelity "Nigerian gospel artiste, Sammie Okposo don openly apologise to im wife Ozioma say e dey intimate wit anoda woman during im recent trip to America for di ending of 2021. Oga Sammie wey post di open confession for im social media page say im bin dey involved inside intimate relationship wit a lady wen e travel abroad. Di artiste wey dey popular for im Wellu-Wellu song also publicly tell im wife, say im dey very sorry and e regret im actions as e know say im don cause her plenty pains. ""On my recent trip go USA (late 2021), I dey intimately involved wit a lady, I know say dis one no dey appropriate as a married man and a minister of di gospel. I dey ashamed and regret my actions as e don cause plenty pain to my dear wife, Ozioma, my family and I. ""To my wife, Ozioma, I am sincerely sorry say I put you through dis shameful and embarrassing situation. I break your trust and disappoint you. Your forgiveness of my moral failure and poor judgement dey important to me. I pray I go eventually dey able to build back di trust and confidence every single day forth."" E tok. E also apologise to im fans and oda ministers of di gospel for im behaviour and im moral failure. ""I wan take dis moment and apologise to all fathers and mothers of di Faith and ministers of di Gospel for my behaviour and moral failure. To all di pipo wey don be part of my ministry, follow my ministry or know me personally, I dey truly sorry for disappointing you. I regret any pain or disappointment wey dis news of my moral failure and poor judgement fit don cause una and I dey truly sorry for disappointing you. I humbly ask make you continue to pray for me."" Oga Sammie add say im dey suspend imsef from all ministry work until e get full restoration. Plenty reactions don follow di gospel artiste confession for Twitter. Sammie Okposo na multiple award winning Nigerian gospel artiste, music and video producer. Dem born am for 20 May 1971 and e come from Delta state, South-South Nigeria. According to im Twitter profile, e be United Nations Youth Ambassador. One online media, Believers Portal say oga Sammie start im music career for 1995 wen e join di Nigerian movie industry as a sound track producer before e later enta into full time music production. For 2000, e carry African music enta anoda level wen e release im first album, Unconditional Love. Di hit track of di album, ""Welu Welu"", gain plenty local and international popularity. For 2004, American ambassador to Nigeria bin invite Okposo to perform for di Martin Luther King Day and July 4th Independence day Celebration. E marry im wife Ozioma for July 2010." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60123963 +sports Ighalo: Manchester United don extend di Nigerian striker loan deal until January Manchester United don reach agreement with Shanghai Greenland Shenhua to extend di loan deal for Odion Ighalo. Di Nigerian striker deal with United bin suppose end for 31 May but im go now remain with di Reds until 31 January 2021. Dis na according to informate for Manchester United official club website. Ighalo don score four goals for di eight games im don play for Manchester United. Today confirmation na big boost for United manager Ole Gunnar Solskjaer, as im continue to dey prepare im squad for dis month resumption of competitive football. United dey fifth for table, three points behind fourth-placed Chelsea with nine games to play. Solskjaer side dey quarter-finals of FA Cup and dem get five-goal lead going into di second leg of dia Europa League last-16 tie against LASK. https://www.bbc.com/pidgin/sport-52879517 +sports Champions League: Prediction for Villareal vs Liverpool semi-final match "Villarreal go meet Liverpool for di second leg of dia Uefa Champions League semi-final match on Tuesday. For di first leg for Anfield di Reds beat di Yellow Submarines 2-0 wit own goal from Estupinan and goal from Sadio Mane. Moral high for Jurgen Klopp team wey still dey eye di quadruple dis season. Di winner of dis game go play either Manchester City or Real Madrid for di final wey go happun for Stade de France for Paris. Dis na eviritin you need to know about di game. ""Villareal don give many teams tough time dis season for Champions League,"" football sabi pesin Bolarinwa Olajide tok ""But injuries affect di Yellow Submarines for di worst possible time, and dem offer almost nothing for di first leg defeat for Anfield. ""Liverpool dey go into di second leg wit a refreshed side and dey look almost unstoppable and suppose book dia place for di final wit ease,"" e add. Prediction: 0-2 (Agg: 0-4) Villarreal Form (all competitions, di most recent first): LLWWDDW Wia dem dey for table: 7th for Spanish Liga Form (all competitions, di most recent first): WWWWWDD Wia dem dey for table: 2nd for Premier League. Liverpool also don reach dis season FA Cup final and na dem win di League Cup. Villareal vs Liverpool kick-off time Di Champions League game go shele by 8:00pm (WAT) on Tuesday May 3, 2022. And na for Estadio de la Cerámica, stadium for Villarreal dem go play di second leg. Where to watch Villarreal vs Liverpool Di game go dey live for Supersports on DSTV if you dey reason to watch am for Television for Nigeria and Ghana. Unai Emery, Villarreal coach tell Uefa: ""Our home form good. Starting di game 2-0 behind get as e be. We go try to create situations for di game to allow us to come close to equalising. ""Di removal of di away goals rule benefits us. Di home factor bin dey key for Liverpool but we manage to defend well and avoid to give dem more of an advantage. ""We dey highly gingered to play our game. We want to enjoy dis moment wit our fans."" Jürgen Klopp, Liverpool coach tell Uefa: ""We go need to dey ready to play a top game because dem go come for us wit high press and try to play much more football than we bin allow dem for di first leg. ""Unai go try to adapt a few tins to our style. ""We no expect say Champions League semi-final go dey easy, and dis no dey easy. You no go know if we go ever get chance like dis to go final again, so we go treat am carefully and dey ready - and we go dey ready.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-61292479 +sports Coronavirus: Why FA ban Tottenham's Dele Alli for one match Tottenham midfielder Dele Alli don chop one match suspension by di Football Association afta one post wey im make for social media about coronavirus. Alli, 24, put video for Snapchat for February wia im joke about di coronavirus outbreak and and bin look like im dey yab one Asian man. Dem tell di England international say im get fine of £50,000 and say make e go take education course. Dis match suspension mean say e go miss di Tottenham home match against Manchester United for 19 June. Di video im bin post show im dey wear face mask for airport lounge before im point di camera for one man wey look Asian come zoom di camera for soap wey dem dey use wash hand. For im hearing, Alli say in bin click for im brain sharp-sharp say di video fit cause wahala and im bin delete di video before im board di plane and say na im friend bin cast am come sell di video from im private account give media. For statement for response to di ruling, Alli tok say im dey sorry for any offence im bin cause cos, as im no like racism of any kind at all, at all and im realise say na very yeye joke for something wey don affect plenti pipo. https://www.bbc.com/pidgin/media-53016548 +entertainment Tonto Dikeh: Actress react to viral audio wia she dey beg ex-boyfriend Prince Kpokpogri for second chance "Nigerian actress Tonto Dike don react to one leaked voice recording wey reveal as she dey beg her ex-boyfriend Prince Kpokpogri afta one misunderstanding between dem. Di audio wey don go viral show as Tonto dey cry and beg Prince Kpokpogri for inside one argument wey relate to cheating mata. However, di actress don enta social media to clear di air. For her Instagram page, she tell her fans to ignore di illegally leaked voice recording wey be private conversation between her and her ex. She say di old audio recording na mata wey happun for di past and e no get anything to do wit dia recent issues. For di voice recording wey last for more than 8 minutes, e reveal how di ex-lovers dey discuss about their relationship issues. Prince Kpokpogri bin dey tok im doubts about di relationship, how one man take enta her room for early in the morning and stay there all through di night, im peace and how di relationship wey neva reach three months dey full of crisis. ""Di relationship neva even reach 2 weeks we don begin get crisis. For relationship wey neva reach three months, see di crisis. I tell you right from day one, say I no like trouble. I dey very peaceful, I dey run from anyting wey go threaten my peace,"" e tok. Tonto wey dey cry and beg Prince Kpokpogri for di leaked audio say make e try believe and understand her. ""Please if I beg you like dis to be wit me, how much more I go need to beg you, I dey exhausted"", she tok. Prince Kpokpogri also question why man go come her room from 2:30am till di following morning and e want make im think otherwise. She explain say nothing happun between dem and na her truth be that. At one point for di conversation, Tonto begin cry and beg Prince Kpokpogri to take care of her son, King Andre incase anything happun to her. She also tell am make she no allow her ex-husband and im papa, Churchill Olakunle near di boy and make e take di boy as im own child and raise di child like im own. Prince Kpokpogri tok say even if he wan give am second chance im no go do am as e see say she dey blackmail am wit suicide. However, Tonto don clear say na old audio recording and she say every blackmailer go face di law. ""Be rest assured say every blackmailer go dey brought to justice, na di law and I dey at peace as I know say di law go take di course."" Meanwhile, Prince Kpokpogri don tok say no be im release di audio. For one Instagram post, Kpokpogri say ''I no get much to say about di tape. I sabi how dramatic you re more dan odas... make pipo read demsef who dey behind di leaked voice wit her verified page''. Tonto Dike and Prince Kpokpogri relationship been first enta public eye afta one lavish birthday she organize for June. But na for July di actress bin officially confam say she dey in a relationship with Prince Kpokpogri. Dis na afta tori bin fly up and down about her current relationship status. Di Nollywood actor tag Prince Kpokpogri inside social media post where she dey count her blessings and also refer to am as her 'husband'. She say ""I ADORE YOU @kpokpogri @kingandre_dikeh and all our kids. Thank you to MY HUSBAND."" For di video she post for her verified Instagram handle, e show her and Prince Kpokpogiri for di graduation ceremony of her son, King Andre, di son she get wit her ex-husband Churchill Olakunle. Madam Tonto write say God don answer one of her secret prayers as e give her man wey stand wit her as her head and as a father to her son. She thank God for her new status as she declare say if ""happiness na pesin, e for be her."" Tonto Dike and Prince Kpokpogri relationship saga Recently, plenty rumours bin dey fly say di two lovebirds get issues before Prince Kpokpogri come out to officially confam say dem breakup because di actress bin cheat on am. Dis dey come as tori comot say di Billionaire businessman and Tonto Dike don say bye-bye to dia less than 3-months old relationship. Reports bin first comot for some local blogs to sama alleged infidelity claims on di businessman wit some receipts to show. Taking to im social media to react to di news, Prince Kpokpogri share one video of himself dey vibe to one song as im dey hail di actress ex-husband, Olakunle Churchill. ""No be not about ranting! Come out wit your full chest wit Evidence! To di noisemakers, to your tent oh Israel! @Olakunnlechurchill You be man. Helen of Troy', he tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58485243 +sports Australian Open: Naomi Osaka win title after she beat American Jennifer Brady "Naomi Osaka na di Australian Open champion! Osaka from Japan, work her way to become di queen of hard courts after she beat American Jennifer Brady for di Australian Open final to win her fourth Grand Slam title. Di 23-year-old win 6-4 6-3 win to carry di trophy. Osaka win her number four Grand Slam title, and her second for Melbourne Park, to continue her winning run, wey stand at 21 matches today. She never lose any match since February 2020. ""E dey incredible to get fans, I play di last Grand Slam without fans, to have dis energy mean a lot,"" Osaka tok as she hold her Daphne Akhurst Trophy. Now she don win two Australian Open titles after her victory for 2019, with her other Grand Slam successes wey come for di US Open for 2018 and 2020." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56136710 +health How hospital staff allegedly cut flesh from forehead and right arm of dead woman for Ibadan Di family of Rachael Osanyintolu wey her body part dey missing shortly afta her death say dem wan know pipo or di pesin wey cut some part of her body. Oludare Osanyintolu, son of di late woman say di incident happun for di hospital wia di old woman dey take treatment before she die. E say di pipo wey cut im mama body part know wetin dem dey do. Police don already arrest some suspects sake of di mata wey bin lead to protest. Members of di late woman family bin carry protest go di hospital on Monday to demand di return of di body parts wey dem allegedly remove. Osanyintolu for interview wit BBC Yoruba say im mama still dey bleed wen dem wan recover her deadi body from di hospital. Di incident happun for Ibadan, di Oyo state capital for South west Nigeria. Tori be say di 91 year-old Rachael Osanyintolu bin dey sick before her pikin dem cari her go hospital. Her son say dia mama bin get anaemia wey dem don dey manage for some time. Dis na why dem cari her go hospital for Ososami area of Ibadan. “Dem dey treat her for hospital before dem call me to say she don die. Dis na afta dem do give her oxygen. And na for night all dis tins dey happun. “As we confam say she don die na im we beg di nurses wey dey on duty to help us keep her till morning becos e don late to begin go look for di mortuary wey we go like keep her. And dem gree,” e tok. Oludare Osanyintolu explain say as dem return di next morning to move di body go mortuary na im dem discover say mama forehead dey missing. E say, “Out of curiosity we decide to check oda parts of her body only to also discover say dem cut some part of her right arm comot. “We ask di pipo wey dey dia say wetin happun, dem say dem no know. “Di part wey make we dey wonder pass na say she still dey bleed afta all di cuts. How e dey possible say pesin wey una say she don die come still dey bleed. “Na dis one make we call police and Amotekun.” E tok. Officers of di Oyo State Police Command say dem don arrest di security guards and some staff of di Ibadan Central Hospital. Di arrest na based on allegation say dem tamper wit di part of patient wey die for di facility. All di pipo wey dem arrest also dey detention. Oludare Osanyintolu say dem wan know who cut di body part and wetin di pesin wan take am do. E also want make goment and sabi pipo explain how e dey possible for pesin wey dem don pronounce dead for hours wey still dey bleed. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw0620wg73no +sports Chelsea make progress on De Ligt mata, Arsenal, Man Utd battle for Dybala Chelsea dey make progress for dia attempt to sign Netherlands defender Matthijs de Ligt, 22, after Juventus soften stance on di price. (CBS Sports, Twitter) Manchester United dey look to challenge Arsenal for di signing of Paulo Dybala, who be free agent after im Juventus contract expire, while Napoli also dey interested in the Argentina striker, 28. (La Repubblica, via Star) Manchester City's Portugal midfielder Bernardo Silva, 27, tell im agent say he want join Barcelona dis summer. (Sport) Arsenal dey scheduled to meet Ajax next week as di battle to sign dia Argentina defender Lisandro Martinez intensify, with Manchester Unitedhaving make bid for di 24-year-old. (Athletic) Manchester United don agree fee with Barcelona for Netherlands midfielder Frenkie de Jong, 25, but dem still dey negotiate add-ons, and personal terms. (Fabrizio Romano, Twitter)\n\nJuventus go next week complete di free signings of France midfielder Paul Pogba, 29, and Argentina winger Angel di Maria, 34, after dem leave Manchester United and Paris St-Germainrespectively. (Fabrizio Romano, Twitter) Leeds United and AC Milan don make enquiries for Sassuolo's Ivory Coast midfielder Hamed Traore, 22. (Corriere dello Sport, via Yorkshire Evening Post)\n\nWest Ham neva reach agreement to sign Netherlands winger Arnaut Danjuma, 25, from Villarreal and di deal no dey closer to getting done. (Fabrizio Romano, Twitter) PSV Eindhoven dey keen on re-signing Netherlands midfielder Georginio Wijnaldum, 31, from Paris St-Germain. (Eindhovens Dagblad - in Dutch) Chile midfielder Arturo Vidal, 35, don turn down Boca Juniors to join Flamengo on 18-month deal after leaving Inter Milan as free agent. (Mail) https://www.bbc.com/pidgin/articles/c88wyy8g0zeo +entertainment Rema Twitter rant set social media on fire - See six 'pipo' di Nigerian musician sub "Nigerian singer Rema don go on Twitter rant wia im drop strong word for different pipo including fans, haters, goment and im fellow industry pipo. Inside 24 series of tweets wey im drop on September 28, 2020, im pour im mind about different issues. Di tweets don make pipo dey compare am to American rapper Kanye West wey dey like go on dis kain ranting. Di messages dey very long and indirect, making am hard to decode who exactly Rema dey refer to. But dis na 5 pipo wey Rema sub for di Twitter rant. E be like say Rema don get im own fair share of rejection and heartbreak. Di singer tell di girl wey reject am before im blow say im don dey chop di benefits of di pain wey di rejection cause am now wey im don dey popular. Di 'Lady' singer share say wen im still be upcoming artiste, im first sound engineer abandon am sake of say im bin no fit pay di guy dat time. Na im producer, Ozedikus bin come thru for am wit beats wey im sneak out for Rema to record wit. According to am, all di beats wey Ozedikus sneak out for am don turn to hit songs. Rema also get word for di Nigerian goment. Im chook mouth for di new police law goment just sign wey dey cause serious vexation for di kontri. Di new law go allow police officers to dey search anybodi wey dem suspect say na tiff without warrant and fit arrest di pesin too. Rema say di outrage on Twitter no de enough, say make pipo wake up. Di singer also change am for show promoters wey no dey let am bring im ideas to life sake of say ""dia stage no strong"". Rema complain say di show promoters dey limit am even wen im dey ready to pay from im pocket to bring im ideas to life. Im come advise dem to build stage wey dey strong, say im generation wan party and scatter stage. Most of im fans just dey find out for di first time thru im Twitter rant say Rema bin lose im brother. According to Rema, wen im brother die, only two of im friends bin dey im death bed but wen im bin dey throw house parties wen im still dey alive, evribodi go show. Di singer say na sake of dis kain tin, im no dey comfortable around pipo because im feel say pipo only love for wetin dem fit gain from am. E no too dey clear wetin di singer dey refer to but im demand explanation for im papa death from di Peoples Democratic Party wey be Nigeria main opposition party. Some fans begin dey call on Don Jazzy - di owner of di Mavin record label wey Rema dey signed to - make im change di singer password so im go stop to dey tweet. But instead Don Jazzy encourage pipo to continue to dey read Rema tweets say di singer dey pass important message. You fit read di rest of di singer tweets for im verified Twitter page @heisrema." https://www.bbc.com/pidgin/54329724 +entertainment BBNaija Kiddwaya say Laycon go win Big Brother Naija 2020 housemates wey dey finals "Kiddwaya say Laycon go win Big Brother Naija 2020 housemates wey dey finals of di lockdown season. Kidd wey recently chop eviction from di reality television show, tok dis one during im interview wit Ebuka Obi-Uchendu. ""I want Laycon to win and I feel say im go win."" Na wetin Kidd tok Im say for di beginning of di show im bin think say na Neo go win but e change afta im hear Laycon music. ""Wen I first hear im song I realise say di boy get potential. If im win I feel say im go do more than some oda housemates."" Na wetin Kiddwaya add put. However, dis week, Laycon dey up for possible eviction on Sunday 20 September, 2020. Wen Ebuka ask say which housemate im dey surprise wey still dey inside di house Kidd say im dey surprise say Triktytee still dey inside di house. According to Kidd ""Triktytee bin get some rough weeks, I think say say e for don waka by now."" Na seven housemates still remain for di house out of di 20 wey bin start di show. Dis week Laycon, Ozo, Dorathy and Trikytee dey up for possible eviction. Nengi win Head of house so she get immunity from eviction for di week while Vee and Neo escape nomination too. So all three of dem dey guaranteed a place for final for di show wey go end for September 27. Terseer Kiddwaya (im real name) na 27 year-old self-employed man wey come from Benue State. E describe himsef as confident, good looking, ambitious and pesin wey dey highly motivated. E say im also dey confident and arrogant all at di same time and love travelling. Being a Big Brother Naija season 5 Housemate don make Kiddwaya dey expect a better and crazier 2020. E describe himself as confident, good looking, ambitious, a daredevil wey dey highly motivated. ""You never know wen your time don finish, so you fit as well go for am"" Dat na Kiddwaya favourite words. ""Getting into health and fitness na im Kiddwaya say be im biggest achievement. I bin dey quite chubby, so I transform my bodi and I don dey consistent ever since."" Kiddwaya papa Terry Waya, wey be famous socialite na London-based Nigerian businessman. Oga Waya age 55 bin reportedly face some kain case for British court between 2006 and 2008. Terry Waya na native of Tiv for Benue State middle belt Nigeria." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54158480 +sports Barca dey eye Reguillon, Marseille enter talks with Sanchez Nuno Tavares go undergo medical with Marseille on Friday after di French side agree loan deal for di Arsenal Portuguese left-back, 22. (Fabrizio Romano) Marseille don also begin toks over signing Chile forward Alexis Sanchez, 33, from Inter Milan. (L'Equipe - in French) Manchester City don give 19-year-old English midfielder James McAtee di green light to go out on loan dis season, with Leeds United and Nottingham Forest showing interest. (Football Insider) Tottenham dey try beat Juventus to di transfer of Italy forward Nicolo Zaniolo, 23, from Roma. (Tuttosport - in Italian) Barcelona dey show interest for di signing of Sergio Reguilon, 25, from Tottenham, if dem no fit get fellow Spain left-back Marcos Alonso, 31, from Chelsea. (AS - in Spanish) AC Milan don agree deal to sign Charles de Ketelaere from Club Bruges, despite say Leeds and Leicester show interest in di 21-year-old Belgium forward. (90min) Palmeiras don reject two bids from Ajax for 18-year-old Brazilian forward Giovani and the Dutch side now get competition from Newcastle and Bayer Leverkusen. (ESPN - in Portuguese) Newcastle United and England full-back Kieran Trippier, 31, say e for join Manchester United last summer, before choosing to leave Atletico Madrid for St James Park for January. (Mirror) Arsenal boss Mikel Arteta leave  30-year-old German goalkeeper Bernd Leno, 28-year-old Spanish defender Pablo Mari and Spanish right-back Hector Bellerin, 27, out of im side pre-season defeat by Brentford, with di three players expected to leave dis window. (Mirror) Everton dey set to receive sell-on fee for Ademola Lookman as Atalanta don agree to sign the Nigeria winger, 24, from RB Leipzig for 15m euros (£12.5m). (Sky Sport Italia - in Italian) Liverpool manager Jurgen Klopp don play down suggestions say Brazil striker Roberto Firmino fit leave this summer after dem link di 30-year-old with Juventus and Newcastle. (90min). https://www.bbc.com/pidgin/articles/c51e64z5zzgo +entertainment Burna Boy Grammy awards 2021: Damini Ogulu biography and how di 'Twice as Tall' singer climb ladder to become 'African Giant' "Nigerian singer, Burna Boy, make history on Sunday, 14, March, wen im win im first ever Grammy under di ‘Best Global Music Album’ category for im ‘Twice As Tall‘ 2020 project during di 2021 Grammy Awards. Di Grammys nomination describe Twice As Tall as ""a masterclass in di vibe and hustle wey don make Burna Boy be international musical force ""Di album features some international artists like Stormzy, Youssou Ndour, Naughty By Nature, and Chris Martin of Coldplay, and get Sean Combs as executive producer. Dey born Damini Ogulu AKA Burna Boy wey be Nigerian singer-songwriter, record label executive, Burna Boy on di 2nd of July, 1991 for Port Harcourt city, Nigeria. E be di only son and eldest of three children to Bosede and Samuel Ogulu. Young Burna attend Montessori International primary school for Port Harcourt (1993-2002) and Corona Secondary School, Lagos (2002-2008). Burna search for knowledge take am outside Nigeria go United Kingdom to study Media Technology for University of Sussex (2008–2009) and Oxford Brookes University (2009–2010) to study Media Communications and Culture. Afta which e do one-year internship with Rhythm 93.7 FM Port Harcourt before e officially launch im professional music career wen e dem sign on to Aristocrat records - wey come make am permanent relocate to Lagos. Burna Boy start to dey produce music wen e dey ten years old. Afta e graduate from college, Burna relocate to London to attend university. Afta two years, e drop out and move back to Nigeria to pursue im passion. Coming from family wey dem love music but wey also value education more, Burna spent most of im summer holidays for UK and in language immersion summer camps for France, Togo, and Cote d'Ivoire, before e finally move to UK wia e picked up di Brixton Patois accents wey don become signature for im music. According to Burna Boy mama, everything na all about music to am wen e still be teenager. She tok say Burna dey always hang around im Grandfather, listening to classical music; no wonder im role model later became di man im grandfather manage, Fela Anikulapo Kuti. Burna Boy don release series of EPs, singles, mixtapes, and albums including e 2018 extraordinary “Outside”. Di award-winning collection lead to Burna Boy U.S breakthrough, wey make am sit for #3 on Billboard’s “Reggae Albums” chart, and dis partly dey ginger by di blockbuster single/video, “Ye”. One of Burna best performing albums, “African Giant”, wey im release for July 2019 don get praise from both Nigerian and international media. Also di “African Giant” album get nominated for di 62nd Annual Grammy Award for di Best World Album category but e no win dat year, as Angelique Kidjo collect di award. Sabi pipo say, Burna dey among di contemporary African music brightest stars and also be di pioneer of di ogbonge genre of music wey im simply title “Afro-fusion”. Burna Boy wey do over 70 performances with over 40 sold-out shows across America and Europe in 2019 alone, start off 2020 with winning three most ogbonge awards for di Soundcity MVP Awards - BEST MALE MVP; SONG OF THE YEAR - Killin Dem featuring Zlatan Ibile and di AFRICAN ARTISTE OF THE YEAR. Afta dis, e get BRIT Awards nomination for di INTERNATIONAL MALE SOLO ARTIST category and di SONG OF THE YEAR category for im feature on Dave's “Location”. Dis nomination make am di first African artist to get nominated for over 20 years and di second African artist to ever get nominated for di Awards' 40 years history, Di first African na Youssou N'Dour. Burna Boy na two-time winner of di BET Awards for di Best International Act category afta dem nominate am di second time alongside South African singer, Sho Madjozi, Stormzy, and Dave from di United Kingdom, Ninho and S.Pri Noir from France, and Innoss’B from Democratic Republic of Congo. E receive gold plaque as im single, ‘On the Low’ go viral for France. E go on to release singles like “Odogwu” and “Wonderful”. For August 2020, Burna Boy release “Twice As Tall” album with Diddy and Timbaland as executive producers. Di project top charts all ova di world, Twice as Tall currently get over 200 million total streams just three months afta e release am. Di ""Monsters You Made"" track feature Chris Martin of Coldplay wey give ogbonge delivery for di track. For October 2020, Time Magazine name Burna Boy as ""TIME 100 Most Influential Pipo class of 2020""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56398638 +entertainment Big Brother Naija Season 5 housemates names: Laycon 'Chinko Ekun' crooner of BBNaija 2020 wey real name na Olamilekan Agbeleshe na one of University of Lagos best graduating students? BBNaija 2020 contestant Laycon wey real name na Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos. Laycon say im no be di Best Graduating Student from Department of Philosophy from University of Lagos in 2016 but im graduate with second class upper wey suppose be first class material. E say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata. E biggest achievement na im song 'Fierce' wey dey for MTV BASE Top ten charts for six months. 20 new housemates wey enta di Big Brother Naija house on Sunday 19 July no go observe social distancing. Dat na because dem don clear dem of any medical condition including Covid-19. During di 10 weeks wey dem go stay for di house Big Brother go assign housemates task wey involve team play wey Big Brother know and di housemates need to find out. Some of di general rules for di house na say di housemates no go get any contact with di outside world, no violence and dem must nominate dia fellow housemate for eviction. Shower hour no go dey dis season according to di organisers. No be only dat one wey dem cancel for dis season. No guest go dey allowed inside di BBNaija house or come in contact wit housemates. Dem also reduce di number of ninja dem too and canel all audience for di live eviction show. Ebuka go host di Sunday live eviction show for empty studio and den cross live inside di Bigbrother house. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53474907 +entertainment Wisdom Macauley: Annie Idibia brother apologize and beg her for forgiveness "Brother to Nigerian actress Annie Idibia, Wisdom Macauley don come out to publicly apologise to im sister afta im bin accuse her of possession of drugs and how she enslave am. Wisdom for inside video wey im post for Instagram say di allegations wey im make against im sister dey false. Im attribute much of wetin im do to di fact say ""im no dey alright and im dey sorry."" Wisdom on Wednesday, for anoda video bin accuse Annie say she enslave am and she dey use drugs. According to Wisdom, im bin don dey work for Annie wey go choose to pay im stipends instead of im full dues. Days later, im sister Annie Idibia, wey also be di wife of music legend, Tuface react to di enslavement allegations by her elder brother, Wisdom Macaulay. Di actress accuse her brother say im dey irresponsible. Wisdom for video wey im post on Saturday say na depression make am go on outburst against im sister. Di actress brother wey come from Akwa Ibom state for south-south Nigeria also use native dialect to apologise to Annie, dia mama and im wife. ""I don come to realise say di route I take no be di right one,"" im tok. A whole lot dey go on, and to feel say your food or your source of income is being taken from you, na wetin make me make all dos allegations against my family member."" ""I dey truly and deeply sorry, my sister no dey on drugs. E come from bad place"". Im bin tok say: ""Hello Nigerians, my name na Wisdom Macaulay, I be di elder brother of Annie Macaulay Idibia. ""I dey cry out for help at dis moment because my life dey threatened. I don dey work with my sister for some time, but she no go ever pay me my dues,"" im tok. ""She go rather send me N20,000 or N30,000…turn me to her slave and she fit decide wen she dey angry to end am,"" Wisdom allege." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60967576 +sports Why Athletics Integrity Unit suspend Nigerian gold medallist Nzubechi Nwokocha "Di Athletics Integrity Unit don suspend Nigerian sprinter, Nzubechi Grace Nwokocha, who win gold for di 4x100m relay for dis year’s Commonwealth Games, provisionally. Dem sama Grace provisional suspension for di use of banned substances, di Athletics Integrity Unit tok for one statement on dia site. Nwokocha, 21, run di anchor leg for Birmingham last month as Nigeria beat England and Jamaica to win gold. AIU tok say dem don already sama am di notice of di provisional suspension. “Di AIU don provisionally suspend Nigerian runner, Nzubechi Grace Nwokocha, for the Presence/Use of Prohibited Substances (Ostarine & Ligandrol) (Article 2.1 and Article 2.2),” AIU tok for Twitter. Ostarine and Ligandrol na both anabolic agents wey dey prohibited by di World Anti-Doping Agency. Nwokocha bin qualified for last year’s Tokyo Olympics and also entered di 100m and 200m for di World Championships in Eugene dand she reach di semi-finals in both events. She be one of di 12 female athletes wey win gold medals for Nigeria for Birmingham 2022. For one interview she tell BBC say di team bin dey disappointed for not winning medal for di world athletics championships for Orgeon and di win for Birmingham na relief. ""E dey good to come up here, executing our race and getting di best out of am. And dis na wetin wey always plan for. And we dey happy with wetin we get today,"" ""We all dey work togeda, e no mata our ages, and we just want to work togeda, get di best out of oursef,"" Nwokocha tok. Provisional Suspension mean wen an athlete or oda pesin dey suspended temporarily from participating in any competition or activity in Athletics prior to final decision at hearing conducted under di World Athletics Anti-Doping Rules or di Integrity Code of Conduct. For doping cases, Provisional Suspension dey mandatory under di World Athletics Anti-Doping Rules following an adverse analytical finding for any non-specified substance on the Prohibited List. Dem fit impose Provisional Suspension on other doping cases depending on di nature and circumstances of di case in question. Provisional Suspension wey dem impose in non-doping case any way ''no mean presumption of innocence and no be early determination of guilt. Rather, na order wey dem make on precautionary basis to safeguard di interests of di sport." https://www.bbc.com/pidgin/articles/clj4480jzg7o +sports Chelsea sign 21-year-old French defender from Leicester City for £70m "Chelsea don sign French centre-back Wesley Fofana from Leicester City on a seven-year deal. France Under-21 international, Fofana join Leicester from French side Saint-Etienne for 2020 – since dat time e don make 36 Premier League appearances. E play just seven league games during di 2021-22 campaign afta e break leg for one pre-season friendly against Villarreal. Chelsea sign di centre-back for £70m plus add-ons. Fofana initial fee make am di 12th most expensive Premier League signing, but e drop to 13 wen Manchester United complete di £81.3m signing of Antony. However, im na di third most expensive Premier League defender behind Maguire and Liverpool Virgil van Dijk, wey join di Reds for £75m for 2017. ""We dey happy say we fit bring one of Europe most exciting talent to Chelsea and further strengthen dat area of our squad, both for dis season and many more to come,"" Chelsea chairman Todd Boehly tok. E say Wesley na better defender wey dey promising and e don already prove im sef for Premier League at a young age. But Fofana say im agree to join Chelsea becos e wa win cup. ""Di two last days dey really big for me and I dey very happy,"" e tok. ""I come here to win trophies - di Champions League, Premier League, FA Cup, Carabao Cup, everi  tin. ""I come here to win and di club dey designed to win trophies so I dey here to kontinu am.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c88yl9g1eklo +business ‘Passage of anti-LGBTQ Bill go fit be bad for Ghana economy’ - US Ambassador to Ghana caution "US Ambassador caution Ghanaians den lawmakers say de attempt to pass de anti-LGBT bill go fit affect de economy. According to Ambassador Virginia Palmer, Ghanaians and lawmakers for be careful wit de move to pass de Proper Human Rights and Ghanaian Family Values Bill 2021. “Dis be harmful not just to de people dem dey discriminate against but e be harmful to everybody” she talk. Virginia Palmer add say “dis go fit be bad to de Ghanaian economy sake of pressure go come from companies go talk say dem no fit out dia headquarters for Ghana sake of dia staff no be safe.” She explain say dem just dey ask for de rights of people to be respected so say dem go fit live peaceful and free from harm. “We no your straight children to be gay, we want your gay children to be safe” she talk during interview on JoyNews. Dis concern dey come up after Ghana parliament give strong indication say dem go push de anti-LGBTQ Bill through before de House go rise. But de anti-LGBTQ campaigners for Ghana believe US too dey discriminate against people wey dey practice polygamy. Leaders behind the anti-LGBTQ Bill dey challenge de position of US Ambassador say dem dey discriminate against other people rights. Lawmaker and Anti-LGBTQ Campaigner, Sam Dzata George believe say de US govment too dey discriminate against right of people to polygamy. “When de US respect de right of people who get more than one wife legally, which be acceptable in Ghana... we go fit have conversation” he talk. “But until dem fit respect rights of persons for US who want be polygamous, then dem no have any moral right to talk” Sam George add. Lawmakers for Ghana dey propose 10-year jail term inside new bill which dey criminalize LGBTQ+ activism in de country. De main objective of de 36 paged document, Proper Human Rights and Ghanaian Family Values Bill 2021 draft bill wan deal plus what dem say be ""propaganda, advocacy for LGBTQI+ den related activities. Reason for de new Bill be sake of recent LGBTQ+ advocacy den activism which dey increase for Ghana. Dis Bill, when passed into law go make am impossible to even support or campaign for LGBTQ+ rights online like social media platforms. Prohibition of LGBTQ+ activities Section 6 of de bill mention say anyone who go engage in sexual intercourse with same sex ""commit second degree felony wey dem be liable on summary conviction…to a term of not less than three years and not more than five years or both."" Prohibition against promotion den advocacy In Section 12 of 36 paged Proper Human Rights and Ghanaian Family Values Bill 2021, ""anybody wey go use media, technological platform, technological account or any other means, produce, procure, market, broadcast, disseminate, publish or distribute material for purposes of promoting activity prohibited under de Bill.” “Or person wey go use internet… commit offence wey dem be liable on summary conviction to a term of imprisonment of not less than five years den not more than ten years,” de bill state." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c979rm0p451o +entertainment Nicki Minaj Baby: American-Trinidadian rapper Nicki Minaj don reveal her baby gender Nicki Minaj don officially confam tori say her first baby don land and say di American-Trinidadian rapper welcome man pikin - a son with her husband Kenneth Petty. Minaj bin give birth at beginning of October, according tori. Di baby sex and name bin no dey revealed then. Minaj cari style announce her baby gender inside one Instagram post wit notes and gifts she received from Beyoncé, Kim Kardashian and Kanye West, and Burberry's Chief Creative Officer Riccardo Tisci among odas. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54565704 +sports Brazil vs Nigeria: Super Eagles list of players wey go play Brazil Nigeria Super Eagles don announce dia list of invited players wey go face Brazil for friendly. Super Eagles coach Gernot Rohr put players like Alex Iwobi, William Troost-Ekong, Samuel Chukwueze and Wilfred Ndidi for di list of 23 players wey go travel go Singapore to play Brazil. Red hot Lille of France striker Victor Osimhen wey don score six goals for French league go dey expected to lead di line again. Rohr hand first time call up to Peter Olayinka and also recall Ramon Azeez to di Super Eagles for di first time in five years. Di match go take place for di Singapore National Stadium on October 13, 2019. Goalkeepers: Francis Uzoho (Omonia FC, Cyprus); Ikechukwu Ezenwa (Heartland FC); Emil Maduka Okoye (Fortuna Dusseldorf, Germany). Defenders: Olaoluwa Aina (Torino FC, Italy); Abdullahi Shehu (Bursaspor FC, Turkey); Chidozie Awaziem (CD Leganes, Spain); William Ekong (Udinese FC, Italy); Kenneth Omeruo (CD Leganes, Spain); Jamilu Collins (SC Padeborn 07, Germany); Oluwasemilogo Ajayi (West Bromwich Albion, England). Midfielders: Alexander Iwobi (Everton FC, England); Anderson Esiti (PAOK Salonica, Greece); Oghenekaro Etebo (Stoke City FC, England); Wilfred Ndidi (Leicester City, England); Joseph Ayodele-Aribo (Glasgow Rangers, Scotland); Ramon Azeez (Granada FC, Spain). Forwards: Victor Osimhen (Lille OSC, France); Moses Simon (FC Nantes, France); Samuel Chukwueze (Villarreal FC, Spain); Samuel Kalu (Girondins Bordeaux, France); Paul Onuachu (KRC Genk, Belgium); Emmanuel Dennis (Club Brugge, Belgium); Peter Olayinka (SK Slavia Prague, Czech Republic). https://www.bbc.com/pidgin/tori-49842800 +entertainment Priyanka Chopra memoir Unfinished: Nick Jonas, Bollywood, Hollyood and oda tins di ex Miss World tok about for her new book "Di former Miss World and Bollywood turned Hollywood star, Priyanka Chopra Jonas memoir ""Unfinished,"" don finally come out and di actor for inside video wey she post on her social media handle say she dey ""emotional and excited"" as she release di book on Tuesday. She say di book na for pipo wey dey curious about her as she hope say di book go let dem know more about her pass wetin dem dey read for di headlines about her. As di very title of Priyanka Chopra new book, Unfinished, e mean say she still get plenty things she wan do wit her life. ""Dis na probably di first time as an adult wey I feel di desire to look back and reflect on how I reach wia I dey,"" Chopra tok inside her book preface, as she note say di beginning of a new figurative chapter afta she marry Nick Jonas for 2018 definitely inspire her to become more introspective. From four schools in four years to her pageant days wey open up a whole new world of opportunity but also introduce her to di bad side of di entertainment industry, her rise to di mountaintop as a Bollywood star, from her struggles of getting a place inside Western showbiz, her desire to lead a full, independent life to falling head over heels for one of di Jonas Brothers, Chopra dive deep inside Unfinished. Priyanka parents, army surgeon Ashok Chopra and hospital physician Madhu Akhouri, bin meet for one party for 1981 and her papa wey fall in love at first sight pretend to get fake stomach ache so im go pretend to need Madhu services. Wen Ashok finally get Madhu mama permission to take her daughter out on a date, assure her say na small house party dem dey do, e propose to her during their third dance of di night. Madhu say she neva ready but afta a couple more dates, she realize say dem dey on di same page about all di important things and she say yes. Ashok yarn say he gats secure her permission. ""Wetin make di thirty-two-years marriage dey amazing na because dem no follow di normal traditions of arranged marriage and long engagement as dem marry 10 days later. Priyanka first trip to America na for 1995 wit her mama to visit her younger sister, Kiran Mathur, her husband and two children for Cedar Rapids, Iowa. Kiran carry her go visit di local high school, and she like di school so much. (No uniforms?... Girls fit wear makeup and put dia hair down?""), she ask her mama if she fit stay and go school for America. Afta di ""plenty logical Chopra Family Conversation,"" her parents agree make she move in wit her aunt family. She meet her first boyfriend for her freshman year of high school, one 10th-grader she call Bob (no be im real name). Unfortunately, one of di rules of her aunt household na no dating, so Bob go tell im sister to call di house, den e go collect di phone imself. Kiran later catch am but she agree to Priyanka request to take summer school but she no sabi say na because make she fit dey see Bob. Afta her 12th grade she return to India and she bin dey plan to apply to university in Australia to study aeronautical engineering, and she need picture for her application. Priyanka say she go one small portrait studio for di mall and when di photographer ask if e fit take some modelling shots, she say, ""Sure!"" and go house to go collect more clothes. Immediately her mama warn her say dis guy fit be scammer, say she go follow her go di studio if she still wan pose for di guy. Those fotos end up to become di pictures wey she take put in for di Miss India pageant (Na her 10-year old brother Siddhart apply on her behalf because e wan take over im room back). Competing for Miss India, aside from di fact say she she find out di concept of wearing swimsuit with high heels as funny, she dey self-conscious about di scars for her legs, di scars from falling off her bike and climbing trees, stretch marks and even her dry skin. Afta she win di Miss India World title, di next na di 2000 Miss World pageant, wia di contestants come up with questions wey dem pick at random for each oda to answer. Priyanka get Miss Turkey question: ""Who you think say be di most successful woman wey dey live today and why?"" Priyanka answer, ""Mother Teresa,"" because ""I admire her from di bottom of my heart for being so considerate, compassionate, and kind, giving up her life for pipo for India."" But Mother Teresa don die since 1997. But dem overlook di mistake and dem crown Priyanka winner. Afta a year of actually travelling di world as part of her queenly duties, Priyanka return home wit one really bad cold wey turn into wetin she tink say na sinus infection, but wey actually be polyp for her nasal cavity. She bin need surgery. Di polypectomy sound like normal routine, but while di surgeon dey shave away di polyp, e accidentally begin dey shave away di bridge of her nose, wey later collapse. Wen she remove di bandages her original nose don go. Prinyaka say she feel bad and di experience dey very emotional for her and her family and even make pipo dey call her ""Plastic Chopra"" She lose two out of di four films wey dem sign her for within six months of winning Miss World. She don say say she go neva date anybody again afta her painful 2016 break up but she later meet Nick dat same year. Dem later become friends but di 10 years age difference between dem make her dey a bit worried. Dem later get to know each oda and see say dem dey di same page wit wetin dem want in life. Di rest like dem dey tok na history." https://www.bbc.com/pidgin/world-56006732 +health Covid-19 cases in Ghana today: China doctors arrive for Ghana to help local doctors fight Covid-19 pandemic "Doctors from China arrive for Ghana to help de country fight against spread of Covid-19. De eleven member medical team according to Leader of de medical team, Zhuang Shaohui tell Xinhua News Agency say dem get experience as frontline doctors who help China deal plus de coronavirus situation. He explain say 'dem get relevant experiences plus de local doctors go help dem understand better ways dem go take control de pandemic."" Mr Zhuang Shaohui add say some three medical specialists on dema team get de experience to fight de pandemic for China, sake of that dema practical experience go work for Ghana. Covid-19 cases for Ghana start dey rise as de country start dey record 200 new cases daily. Prez Akufo-Addo reveal say Ghana scientists discover new variant of Covid-19 after genomic sequencing reveal say de virus enter de country. Dem find de new strain inside passengers who arrive for de Kotoka Internal Airport. ""Recent genomic sequencing wey wana scientists do de prove say some passengers who arrive test positive for de new COVID-19 variant"" President Akufo-Addo reveal. Ghana health officials isolate de infected passengers but dem start dey do contact tracing among de general population sake of some of dem attend parties, weddings, funerals den tins wey dem no observe Covid-19 safety protocols. Prez Akufo-Addo caution Ghanaians say he no want impose partial lockdown which go affect de economy negatively like last year, but if de cases continue to rise he go impose restrictions on movement to control de spread." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55716188 +health Coronavirus: See how students for dis African kontris dey help fight coronavirus As kontris all over di world dey face shortage of important tins to use fight coronavirus, students for Africa don step forward to show say dem too fit contribute dia knowledge. We look at some of di ogbonge tins wey some students for higher institution for Africa dey do. Dis ventilator na di work of Usman Dalhatu wey be 200 level Nigerian engineering student for Ahmadu Bello University, Zaria. Usman wey follow BBC tok say na one month e take am to build di ventilator and im don already get plans to produce up to twenty of am. Di only tin im dey wait now na approval from Federal Teaching Hospital, Gombe, wey fit come any time now. As billions of pipo all over di world turn to facemask as dia first line of protection against coronavirus, di product don scarce so tey e be like gold for some places. For Tunisia, northern Africa, students for di National School of Engineering for Sousse don begin produce facemask wit 3D Printing - wey be ogbonge technology to manufacture almost anytin. Grach na one of di six students wey involve for di production and e tell BBC say dem dey make 300 per day. Students for Dedan Kimathi University of Technology for Kenya decide on dia own, to begin make important tins like sanitizer, facemask, personal protective cloth, afta dem see say many pipo no fit afford am. Di Vice Chancellor of di school say Ndirangu Kioni say even N95 follow for one of di tins dem dey do. https://www.bbc.com/pidgin/world-52577948 +politics Ipob sit-at-home order for Nnamdi Kanu arrest: Make nobody force anybody to comply - Abia state government "Abia state goment say dem dey actively monitor di situation with Mazi Nnamdi Kanu, di leader of di Indigenous People of Biafra, Ipob wey dey detention for Nigeria. Inside statement on Friday, di goment say dia eye dey di mata of di ""Ipob leader Kanu who be indigene of di state and who dey currently under trial for Federal High Court for Abuja, with a view to ensuring say im fundamental human rights, wey dey contained for di Constitution of di Federal Republic, dey respected."" Di statement wey also chook mouth ontop Ipob call for pipo to siddon for house on Monday, 9, August, 2021 to protest Kanu arrest say make di group no force anybody to comply with dia order. Di statement from di goment wey di Commissioner for information, Abia state John Kalu sign say, ""while goment no go force anybody wey wish to sit at home for any reason whatsoever not to do so, citizens get freedom of movement under di extant Constitution of the Federal Republic of Nigeria, we wish to strongly advice say make nobody also force or enforce any sit at home order from any non state actor as doing so no go serve any known interests of di pipo of di state. Di statement also go further to ask all law abiding citizens and visitors to go about dia normal businesses without fear of molestation as adequate security don dey provided to ensure dia safety. Dis statement dey come as Ipob bin issue notice of weekly sit-at-home order wey dem say go start on Monday, 9, August, 2021. According to dem, dem no go stop to dey sit-at-home every Monday henceforth until dai leader regain im freedom. Dia statement bin also say, ""all institutions public and private, transport companies, schools, banks, markets, airports and sea ports in Biafra land must shut down every Monday beginning from August 9."" But goment statement say, ""compelling our children to stay away from school go only serve di interests of di yet to be properly identified persons who fit no want to see us make progress as a pipo."" Dis dey come as di trial of di proscribed separatist leader of di Indigenous People of Biafra Nnamdi Kanu bin dey adjourned until October 21 2021. For di resumed hearing for di Federal High Court on di 26, July, di presiding judge, Justice Binta Nyako say she no dey go ahead wit di case as di defendant, Nnamdi Kanu no dey physically present for di court. Di prosecution team bin no give reasons for di absence if di leader of di banned group but afta closed door meeting, she bin adjourn di case. She also reject di requests by Kanu lawyer to transfer am go di Nigeria correctional centre afta di lawyers express concerns about im safety and lack of access to am. Kanu dey stand trial for charges wey border on terrorism, treasonable felony, illegal possession of arms, among odas wey di Nigerian goment level against am. Nigeria Minister of Justice and Attorney-General Abubakar Malami bin tell tori pipo for Abuja, di kontri capital say ""Kanu go still answer for di 11 charges wey e bin dey face for court before e try to escape justice. Oga Malami wey also be Nigeria Minister of Justice add say Kanu dey also face accuse of instigating violence wey result to loss of lives and property. Accuse wey Kanu lawyers don deny. Controversy don trail di arrest of di Ipob leader from a foreign kontri and im fast detention for di Department of State Services (DSS) facility - im followers say im arrest dey against fundamental rights. Ontop Kanu arrest and detention, Abia State goment say """ https://www.bbc.com/pidgin/tori-58123058 +entertainment Big Brother Naija 2021 housemates eviction nomination: Arin, Emmanuel, Nini, Princess, Saskay, Tega dey up for eviction Six BBNaija housemates from di 'Shine Ya Eye' Big Brother Naija reality TV show don dey up for possible eviction dis Sunday. Di housemate wey dey qualify to nominate pipo bin nominate Arin, Emmanuel, Nini, Princess, Saga, Tega to leave di house. But di new Head of House, Pere save Saga and replace am with Saskay. Dis one mean say now Saskay go join pipo wey dey up for possible eviction on Sunday. Nomination for di Sunday eviction take place on Monday evening afta di Head of House challenge wey Pere win. Di head of house plus di new housemates wey be; Michael, Kayvee, Jumoke and Queen dey immune from di nomination. Big Brother call di housemates one by one inside di diary room for dem to call di two names of pesin wey dem want to see say dey up for eviction. Boma: Boma nominate Saskay and Princess Cross: Cross nominate Princess and Tega Saga: Saga nominate Princess and Tega Saskay: Saskay nominate Whitemoney and Nini WhiteMoney: WhiteMone nominate Arin and Jaypaul Nini: Nini nominate Princess and Emmanuel Jacky B: Jacky B nominate Saga and Nini Sammie: Sammie nominate Tega and Princess JayPaul: JayPaul nominate Maria and Peace Liquorose: Liquorose nominate Saga and Arin Arin: Arin nominate Emmanuel and Tega Yousef: Yousef nominate Boma and Arin Princess: Princess nominate Saga and Arin Peace: Peace nominate Tega and Princess Emmanuel: Emmanuel nominate Arin and Angel Tega: Tega nominate Nini and Arin Angel: Angel nominate Princess and Emmanuel Maria: Maria nominate Arin and Angel Pere: Pere nominate Princess and Saskay Before today nomination, former housemate like Beatrice, Yerins and Niyi bin leave di house last Sunday as dem get di lowest votes out of those wey bin dey up for eviction. Meanwhile, Afta Pere win di HOH challenge today, e chose Maria im deputy Head of House. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58138167 +business Why cryptocurrency prices dey drop sharparly "Di prices of cryptocurrencies continue to drop for di second day on Wednesday, as investors continue to worry about di stability of di sector. Di financial health of major crypto exchange FTX dey give crypto investor cause for worry even though im bigger rival Binance dey plan one rescue deal. Crypto giant Binance sign one nonbinding agreement on Tuesday to buy FTX international unit – dis np include di U.S. unit - to help cover ""shortage of money"" wey di rival exchange dey face. Di propose deal between di two  big rivals dey come afta one week of speculation about di financial condition of FTX wey lead to di withdrawal of $6 billion within 72 hours before di Tuesday deal. Dis raise questions about how sound one of di world largest crypto exchanges. FTX and Binance no gree tok di condition of dia agreement, and di market no sure weda or not di deal go happun. Investors begin withdraw dia money on Sunday morning afta several tweets from Binance CEO Changpeng Zhao, say im company go sell dia share of FTX native token, FTT due some kain worrying revelation wey dem get concerning di company. FTX founder, Sam Bankman-Fried, reply Zhao tweets say Binance dey “try to go afta us wit false rumours,” and insist say FTX “assets dey fine.” Di revelation wey Oga Zhao dey tok about na one report wey tori pipo CoinDesk publish for early November about Sam Bankman-Fried oda business, trading company Alameda Research. FTX and Alameda na two separate companies. Di CoinDesk report say, one “private financial document” wey e see show say  FTX native token dey for Alameda balance sheet. If CoinDesk informat correct, e mean say around one third of Alameda $14.6 billion asset na crypto coin wey FTX create. E also mean say di two companies no dey independent of each oda as dem claim and dem two get shaky foundation. Dis revelation follow make FTT plus oda crypto price drop. Bitcoin, di biggest cryptocurrency by market value, drop 5.3% in price inside one day to $17,559 around 11:07am, after e drop 10% on Tuesday dis make am di worst day since mid-August. Etherum, di next biggest, continue im loss on Wednesday to hit im lowest since July. ""What if di deal no go through, or (Binance CEO Changpeng Zhao) come back and say I go give 10c on di dollar. Dat na di blind spot wey di market no ready for,"" Scottie Siu, investment director for Axion Global Asset Management for Hong Kong, tok. Di confusion for FTX na di latest sign of trouble for di fast-moving world of cryptocurrencies. Crypto prices don collapse so far dis year sake of wahala for di financial markets wey make investor dump riskier assets. Afta e grow sharply for 2020 and 2021, bitcoin price don fall around 62% for 2022. Kami Zeng, head of research for Fore Elite Capital Management, one Hong Kong-based crypto fund manager, say dis na anoda ""alarm warning"" for di market and say investors suppose dey careful for some time. ""... di whole tin still look like dark hole. We no sure how infectious dis fit be, but I believe institutions need to show dia proof of reserves ASAP. Confidence no go recover before dat,"" Zeng tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c3gj84p4kkpo +sports Shad Gaspard death: How di WWE wrestler take die as im dey try to save im son "Dem don find di deadi body of former WWE wrestler Shad Gaspard for waterside for Venice Beach for Los Angeles afta im miss wen im dey swim with im son. Tori be say strong wave carry di 39-year-old with im 10-year-old Aryeh on May 17. Dem rescue im son but lifeguards no fit save Shad. ""Shad drown inside ocean,"" na wetin Dwayne ""The Rock"" Johnson tok, ""but im tell di lifeguards to save im son first. Dat na di love of a father."" Im add say Shad na ""great guy"" e send im ""deepest condolences and love to im wife, son and family"". ""Dis one pain,"" na wetin im tok Shad wife Siliana don thank di authorities wey rescue her son as di search continue for her husband. ""Shad na fighter, warrior and magical soul. We dey hope and pray for im safe return."" But by 2.19am on Wednesday, lifeguards respond to reports of one body along di waterside of Venice beach for LA. Na later wey di coroners confirm say na Shad. ""I join fans around di world as we remember Shad Gaspard beloved performer and caring father,"" na wetin WWE icon Triple H tweet. Di 6ft 7 wrestler, wey dem dey call Da Beast featured for Tag team Cryme Tyme with partner JTG. ""No be di kind of end we want to hear,"" na wetin fellow wrestler Tyrus post. ""We fit mourn now and celebrate im life as di hero di father di ""beast"". ""You be di definition of wetin e mean to be a father, you give your life without thinking to save your son."" Afta im leave WWE ten years ago, Shad Gaspard start im acting career for TV and films and do small roles for different movies including 2015's Get Hard with Kevin Hart and Will Ferrell. WWE legend Dave Bautista cry as im pay im tribute: Im liked to walk inside di room and commotion - na di kain pesin im be, bigger than life."" Im last appearance for red carpet na di MTV awards: ""I feel like say im bin just dey start to breakthrough with films and now im don go and im no go ever get di chance to live out im dreams. ""im journey suppose inspire you and also im final sacrifice.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-52745213 +sports """Naomi Osaka defeat Victoria Azarenka"" to win 2020 US Open Tennis grand slam - Check out fotos as Osaka lift di trophy" "Naomi Osaka beat Victoria Azarenka 1-6, 6-3, 6-3, to win her second US Open, and di third grand slam of her young career. ""I just want to be di type of pesin wey im think say I gobe. He think say I go be great, so hopefully, I go be great in di future."" Osaka tok on Kobe Bryant belief in her wen she address tori pipo early morning on Sunday as di 22 year old Japanese lift di US Open trophy afta defeat Victoria Azarenka for di finals." https://www.bbc.com/pidgin/world-54136210 +sports Michael Olise: Crystal Palace sign Nigerian-born player for £8m - Tins you need know about am 19-years-old Michael Olise don become di first signing for crystal palace manager Patrick Vieira after e move from Reading to London. Di left foot player go hope to leave im mark on the English Premier League with im new club Dis na some interesting facts about di footballer. E fit represent four kontris - Dem born Michael Olise for England for 2001 to a Nigerian father and France-Algerian mother. Dis one make Olise eligible to represent Nigeria; England, France and Algeria for international football and e don already play for France youth teams. Michael Olise brother, Richard Olise also be footballer wey dey ply im trade for England lower divisions. Olise for im new team Crystal Palace go join anoda player with Nigerian roots Eberechi Eze. Oda African players for Palace include Ivory Coast's Wilfred Zaha and Ghanaian Jordan Ayew. For nations cup qualifier against Benin and Lesotho, Nigerian coaches list Michael Olise as one of di players on stand-by for di matches. Dis one mean say na player wey dem want to wear green and white jersey and if dem bin cap am, e for no dey eligible to play for oda kontris. Im rating for FIFA game don improve - di player bin get 65/100 for im rating for FIFA 20 game but for 2021 version of di game dem move am up to 72 wey show serious improvement for im career. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57774866 +health Coronavirus Lockdown update: Lagos goment don give greenlight for places of worship to reopen on 7 August "Lagos state govnor Babajide Sanwoolu don give greenlight for places of worship in the state to reopen from August 7th . Govnor Sanwo-Olu disclose dis during di briefing on COVID-19 for Lagos House in Marina. Goment bin don close down places of worship since March as part sake of to prevent di spread of coronavirus. Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri but di Lagos State goment no gree allow worship centres for di state to reopen. Now govnor Sanwoolu tok say while mosques fit reopen from Friday August 7, churches go follow suit on Sunday, August 9. ""Places of worship in Lagos go now open from Friday, 7th of August for our Muslim worshippers, and on Sunday, 9th of August for our Christian worshippers."" Govnor Sanwoolu tok. ""We go allow only 50 per cent of dia maximum capacity, either for church or mosque. Churches wey dey worship on Saturdays go also dey allowed to hold worship. ""Place of worship must to have dia regular once a week service on days dem choose. ""We go monitor this for di next couple of weeks and see how dem dey observe am. We dey encourage dem to have multiple services on those days but it must dey restricted only those days of worship. ""Regular gatherings dey permitted to hold but vigils and other services go still dey on hold for now. But di govnor draw ear give old pipo. ""We recommend and seriously beg our senior citizens - if you be 65 years and above, we strongly advise say make you no attend these places of worship. Please stay for house."" According to him, religious leaders must to make available hand sanitisers, handheld thermometer checks. Di govnor don also increase di number of pipo wey dey gather from 20 to 50. E add say di state government go ensure say social distancing dey maintained. E also announce say Secondary schools for di state fit also reopen from August 3rd but dis na for those wey dey for examination classes. E give news say pipo go fit dey enta restaurant siddon chop from August 14 but make dem follow all Covid- 19 health protocols. According to di Nigeria Centre for Disease Control as of Friday night, Lagos record ova 15,000 Covid-19 infections and about 200 pipo don die. Lagos na im get di highest number of coronavirus cases for di kontri. We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori." https://www.bbc.com/pidgin/53624536 +politics 'We go change Nigeria for good' - Peter Obi tok for Labour party campaign flag-off Jelilat Olawale BBC News Pidgin Di Labour don officialy staart dia presidential campaign ahead of di 2023 Nigeria general elections. Di rally happun on Saturday 29 October, for Lafia, Nasarawa state capital for North-Central part of di kontri. Presidential candidate of di party Peter Obi and im running mate, Datti Baba-Ahmed; plus di oda members of di party 1,234 campaign council members dey in attendance for di wey plenti supporters attend. Recall say Obi bin earlier postpone di flag off to go visit some part of di kontri wia flood don scata and render pipo homeless. E also also ask oda presidential candidates to pause dia campaign sake of di flooding and pay respect to di victims. Di Director General of di campaign council, Doyin Okupe say di campaign train go dey massive across all di six geopolitical zones of di kontri. Peter Obi, 61 promise to solve Nigeria flood challenge and ensure say di kontri attain sufficiency for food production if dem elect am for 2023. E say im goment go move Nigeria from consumption to production and job creation. Obi also promise to fix Nigeria power palava, amongst odas. E come wonder why di Super Eagles no no fit qualify for Qatar 2022 World Cup wey dey start next month. “I dey assure you now say if we come into power, we go solve dis flooding problem.” Obi tok afta e don obeserve one minute silence in honour of di pipo wey die for di flooding wey don cause gbege for di kontri. “We no go do am overnight but we go begin dey solve am. E no go take 30 years. Di Federal Goment say e go take 30 years, e no go take 30 years for us to solve am. “Make I assure una, di goment of Obi and Datti Baba-Ahmed go change Nigeria for good,” e tok for di rally. Di Labour party candidate also promise say e go support farmers and youths for di di kontri. E add join say Nigeria fit feed imsef if dem take correct measures. “If we enta goment, I assure una, farmers go go back to farms because we go deal with insecurity, we go support youths; di more youths dey pulled comot from poverty, di more we go reduce criminality. “We will support youths because today Nigerian youths don’t have a home. When we come into government, the youths will have homes because we will solve their problems.” “Today for Nigeria, pipo dey spend all dia money to feed emselves. So many pipo no even fit feed demselves. We go make sure say we start di journey of Nigeria being sufficient for food production. If Israel fit feed imsef, Nigeria fit feed imsef. If India fit feed imsef, Nigeria fit feed imsef,” e tok. ''Di goment wey we go form go be goment of youths and women. E no longer go be goment of old pipo. ''Governance no be retirement home'. No be old pipo home. I go form goment wey dey energetic', look at di two of us , we dey ready for di job, we sabi una problem.'' Obi continue. E come tell im supporters to ensure say dem support am and make dem also campaign for am. ''Support us. Start to dey campaign for us. For your future no listen to dis pipo wey dey share money. Na una money wey dem steal’’ ‘’We go give una back your future’’ Obi tok as im supporters chorus im name. Nigeria presidential and National assemly elections go happun for 25 February , 2023 while govnorship and state assemblies election go take place across di kontri 11 March same year. Na 18 presidential candidates wey Obi dey part of go contest for di highest political seat for di kontri. https://www.bbc.com/pidgin/articles/clm8vkmyygpo +sports Anthony Joshua vs Pulev: Joshua knockout Kubrat Pulev after ninth round to remain World Heavyweight Champion "Unified world heavyweight champion Anthony Joshua combine power and patience as im knock out Kubrat Pulev to retain im World Heavyweight titles. Joshua victory over Pulev don trigger hopes say a historic fight against Tyson Fury fit soon become reality. Di heavyweight drop e mandatory challenger to di canvas twice for round three. Joshua, step off di gas and allow Pulev to at least offer some small threat, but many uppercuts from Joshua for di ninth round drop Pulev and one straight right hand wipe am out seconds later. Di 1,000 fans wey get access to di Wembley Arena, wey be venue of di fight witness a blend of di boxing skills and crushing punches wey don help build Joshua into di attraction wey im be. Moments after di fans roar at di prospect of di IBF, WBA and WBO champion facing WBC champion Fury next, Joshua tok say: ""I start dis game in 2013, gathered di belts. ""Whoever get di belts I want to compete wit. If na Tyson Fury, let it be Tyson Fury."" For e last two outings, Joshua don face serious pressure. A second defeat by Andy Ruiz Jr for December for leave e career in tatters. But im bin dey punch perfect on di night. Defeat here for make am di instant fall guy in di midst of public demand for di Fury fight. But once again e ginger im swagger. Some go ask why Joshua bin dey unable to end things more quickly but after one year out of di ring, im control dis fight." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55290923 +business Violent clash for Alaba International market, wetin we know Police say dem don restore normalcy for Nigeria major electronic market, Alaba International wey dey for Ojo area of Lagos state. Benjamin Hundeyin, tok-tok pesin for di Lagos state police command give small informate about wetin fit don lead to clash but e say demstill dey torchlight di mata. Tori come out early Wednesday say violent clashes dey happun for Alaba. Na so pipo also begin post security advisory for social media say make pipo avoid di area sake of how di clash fit escalate. Some videos from pipo wey claim say dem dey di area wen di kasala bust wey for Alaba bin spread online. One of dem show wia plenty pipo dey carry stick and different kind of materials dey waka for inside di market. Anoda one show wia pipo dey run for inside di market. One of di officials of Alaba market, Emmanuel Amaife tell BBC say na “touts dey cause di kalasa wen dem tell dem say make dem no dey park pipo cars anyhow inside di market.” E say di touts dey collect money from pipo wey park dia cars and dem just dey do am anyhow. Di police wey still dey investigate say na mata dey between two groups. “Wetin we hear be say di clash na between some road transport workers and officials of di market,” Hundeyin tell BBC. E say “Preliminary investigation show say di road transport workers wan create park inside di market but di officials of di market dey resist dem. “Na di resistance make evri wia rowdy like dat.” Di police tok-tok pesin also say dem neva get any report of casualty for di market so far. But eyewitness wey tok to BBC say ova 20 pipo bin get different kain injuries for di kasala. Benjamin Hundeyin say di Police division for Ojo wit officials from di Rapid Response Squad (RRS) don deploy go di area. And di Area commander, Igbafe Afegbai don take charge of operations for Alaba market. Foto show wia armed officers don position for some part of di market – anoda foto show wia officers dey follow some pipo tok. “Di normalcy wey don return na becos our men dey on ground and if need be we go deploy more men go di place,” e tok. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4n8e6rdrlwo +entertainment Big Brother Naija Season 5 housemates names: Nengi wey real name na Rebecca 'Nengi' Hampson na di first Head of House for BBNaija 2020 "Rebecca 'Nengi' Hampson don become di first Head of House for di ongoing 2020 Big Brother Naija reality TV show. Nengi win di special position afta defeating oda contestants wey bin do di challenge. She come pick Florence 'Wathoni' Anyansi, her fellow housemate, as her deputy. Both Nengi and Wathoni go enjoy di HoH room and every benefit wey come wit am. Nengi, na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures. She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef. She be proud Capricorn. Deputy Head of House: Wathoni, na 29-year-old fashion entrepreneur. Florence Wathoni Anyansi na 29-year-old fashion entrepreneur and she be single mother wey dey do her fashion business and parenting blog at di same time She say she fit speak and write Swahili wella as her mama na from Kenya and her Papa na Igbo. Organisers of Big Brother Naija 2020 bin don earlier announce inside one statement say dis year edition go witness upgrade in terms of benefits wey di Head of House (HOH) go fit enjoy compared to winners from previous ones. ""Dis year, di HoH privileges go see some major upgrades. For dis new season, di Head of House go get to enjoy a lounge all to themselves! Di HoH lounge go get living room area, bedroom, fitted bathroom, and a private bathroom,"" Di organizers tok for statement. ""Additionally, di HOH go dey allowed to select a deputy to assist dem to cari out dia duties and dem fit get to add some BBNaira to dia Betway Wallet....""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-53482633 +entertainment Guardian Angel Wedding: Guardian Angel and Esther Musila marriage fotos reaction "Kenya gospel singer popularly known as Guardian Angel don share beautiful fotos from im marriage with Esther Musila. Audiphaxad Peter Omwaka and im wife share beautiful photos of dia wedding for dia social media accounts. Guardian Angel and Esther do private wedding ceremony wey dia close friends and family attend on Tuesday January 4, 2022., according to local media dey report. Di gospel singer share pictures of both of dem and write for im verified instagram handle say; ""And on my birthday, God do am again. Mr.& Mrs. Omwaka."" For her own post, di bride post say; ""To find someone as special as you out of all di pipo for di world na something I neva imagined. Make we do dis life togeda. Mr & Mrs Omwaka."" Afta di couple post dia wedding fotos, fans and celebrities don rush go dia comment section for social media and begin write plenti congratulation messages. Here na fotos wey Guardian Angel & Esther Musila share. Guardian Angel bin propose to Esther Musila for May 25, 2021 and she post say she say 'yes' to di proposal. Di Kenya gospel singer propose to Esther during her surprise Birthday Party and she no fit hold back her tears. Dis Kenyan couple be of public interest because of di many twists to di a love tori, according to different media report. Na so different reaction dey come from Kenyans inside twitter. While most pipo dey send dia congratulations message, some odas dey tok about age difference wey dem claim say dey between di couple. Odas wey no like di way di reaction dey go for social media advise pipo to leave di couple to enjoy dia union. Celebrity wedding na normally a big deal for fans and oda followers of di celeb wey dey wed. Audiphaxad Peter Omwaka Aka Guardian Angel na Kenyan top Gospel Musician, Songwriter and multi-talented Instrumentalist wey dey play both di guitar and piano. E don dey follow im music career for more than six years and na host of award nominations locally and for di greater East African region. Guardian Angel don release plenti chart topping songs wey don place am among big household names for Kenya music scene. Some of im popular songs include Nadeka, Amazing Grace, Liwe Liwe, Pendo and Rejea. For im Youtube page, Guardian Angel describe im music as music for di soul wey dey seek to encourage pipo to believe in God and bring dem back to God presence through repentance, true worship and praise. Im main ginger for dis passion na to do music wey dey relevant now and many more years to come. Before now, Guardian Angel clear di air about im relationship with Esther Musila during one interview with Jalango TV as pipo dey criticise dia age difference; ""Listen, di word tok say 'you go come togeda and become one'. If dis woman dey older than you or your mother, di minute you agree to become one, all dis tok-tok go end and she go become your wife."" ""So If we don agree to marry each oda, she be my wife. E no mata how old she dey, I be di husband. You understand? dat na if at all we don marry."" Guardian Angel add say which ever decision e don make, weda love dey or dem dey in a relationship or weda dem love each oda no mata. Wetin mata na weda both of dem dey happy and dey do di right thing. ""Who ever feel say I don do di wrong thing, abeg I want to ask you first for forgiveness for what ever reason."" ""Then secondly I want to ask dat pesin to give me di script of my life wey God give am, for am to tell me woman to marry. If you give di script, I go follow you."" ""If you no get di script, please shut your mouth and let love win,"" Guardian Angel conclude during di interview." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59883761 +sports Brazil vs Senegal: Neymar fail to win for im 100th cap Senegal make sure say Brazil no win for Neymar 100th match as both kontris play 1-1 for international friendly for Singapore. Di two goals for di match come inside di first half as Senegal make sure say Brazil no beat dem for dia first meeting togeda. Liverpool forward Roberto Firmino na im score Brazil goal wen im chip Senegal goalkeeper to open di scoring afta only nine minutes. Senegal Sadio Mane come later win penarity wey striker Famara Diedhiou convert to equalise for Senegal. Brazil go now face Nigeria Super Eagles on Sunday for di same venue on Sunday. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50004154 +sports Nigeria vs Liberia: Prediction, time & how to watch di Qatar 2022 World Cup qualifiers "Nigeria senior national team go begin dia journey to Qatar 2022 World Cup dis weekend. Super Eagles go lock horns against di Lone Star of Liberia for dia qualifying match on Friday. Nigeria and Liberia dey Group C wit Cape Verde and Central Africa. For di African qualifiers, 40 teams go battle am out for ten groups. Only di group winners go advance go di third and final round. Na from dia dem go decide di five teams wey go on to di world finals. Tori be say di Super Eagles don qualify for World Cup six times and dem go dey hope to qualify for Qatar 2022. See eviritin you need to know about di match; Super Eagles of Nigeria go face di Lone Star of Liberia on Friday September 3 and di game go kick off by 5pm West Africa time. For now Nigeria football federation neva tok which station go broadcast di match live for di kontri but wetin we know be say e go dey live for dia social media page Nigeria Super Eagles Dis game go shele for di Teslim Balogun Stadium for Lagos and tori be say 5000 fans go dey allowed to watch di game live. Football commentator Emmanuel Etim feel say di match go dey one sided in favour of di Super Eagles. Etim wey don cover ova 100 matches tell BBC Pidgin say na sake of di quality wey Nigeria get and di history between di two kontris. ""Super Eagles get upper hand onto say dem go play in front of 5000 football hungry fans for di kontri football capital."" Etim tok Prediction:Nigeria 3-0 Liberia. World football join body, FIFA don appoint Togolese official, Kouassi Attisso Attiogbe as di referee for Friday FIFA World Cup Qatar 2022 qualifying match between Nigeria and Liberia wey go take place for Teslim Balogun Stadium, Surulere, Lagos. Attiogbe lines men n aim kontri pipo Komlan Domenyo Adiwotso (assistant referee 1), Limna Kabassima (assistant referee 2) and Yelebodom Gado Bodjona (fourth official). FIFA also appoint Munkaila Nassam Adam from Ghana as match commissioner, while Abdellah El Achiri from Morocco go serve as referee assessor. So far di number of African kontries wey don appear for di World Cup, between France 1938 and Russia 2018, out of a total of 54 kontries wey dey for di continent. Dem be: Egypt, Morocco, Congo DR (formerly Zaire), Tunisia, Algeria, Cameroon, Nigeria, South Africa, Senegal, Angola, Côte d'Ivoire, Togo, and Ghana" https://www.bbc.com/pidgin/sport-58415337 +sports Olympic Games Tokyo 2020: Why PUMA terminate contract wit Nigeria "Nigeria poor outing for di Tokyo 2020 Olympics games don continue wit sporting brand PUMA ending dia contract wit Nigeria. International fashion and sportswear brand, PUMA announce di termination of dia agreement wit Nigeria sake of di disorganisation of di kontri for di games wey dey happen for Japan. First na di disqualification of ten Nigerian athletes by di Athletics Integrity Unit from di games because dem no show up for routine testing. Di athletes protest for Olympics village wia dem carry placards dey blame di Athletics Federation of Nigeria (AFN). ""All we wanted to do na to compete"", ""Dreams shattered,"" na some of di write ups for di cardboard. Di oda incident na di video of Chukwuebuka Enekwechi, anoda athlete wey dey represent Nigeria for Shot Put wia im dey wash im competition jersey sake of say na one jersey im get. Di video of Enekwechi still dey trend for social media. Di latest now na PUMA termination of dia contract with Nigeria. In July 2019 di Athletic Federation of Nigeria (AFN) sign a $2.7m deal wit Puma for Qatar. Di 3 year deal wey suppose end by 2022 cause serious kasala for AFN as di federation even break into two. Di deal of di contract no clear but di major agreement for di sporting brand to supply kits for Nigeria athletes. ""As a direct consequence of the recent developments, particularly at the Tokyo Olympic Games 2020 and pursuant to clauses 9.2 and 7.3 of the Agreement, we hereby terminate di Agreement with immediate effect,"" Edlheimb Manuel, di brand Director write for di letter to AFN. Di letter add say ''PUMA especially declares to be discharged from any or all obligations towards all stakeholders involved and reserves all rights against these entities and individuals."" Di Athletics Federation of Nigeria and di Ministry of Sports never react to dis development." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58095528 +sports Ivory Coast vs Algeria: Mahrez miss penalty afta Nicolas Pepe, Ibrahim Sangare and Franck Kessie score for Ivory Coast to end Desert Foxes Afcon defense Defending champions Algeria don comot from di Afcon 2021 tournament. Di Desert Foxes chop three goals from di Elephants as dem see dia defence of di title wey dem win for 2019 end prematurely. Na Nicolas Pepe, Ibrahim Sangare and Franck Kessie score for Ivory Coast. Di Arsenal star Pepe and im Ivorian team mates press Algeria from di start of di whistle to di end - though Algeria get some break in-between. But Algeria miss dia chance to reduce di deficit afta Riyad Mahrez miss penalty wey hit bar for di match wey happen for di Japoma stadium on Thursday. Meanwhile, Equatorial Guinea go join Ivory Coast to qualify for Group E afta dem beat Sierra Leone for di oda match afta Pablo Ganet goal. Algeria finish bottom of Group E without wining any match for Afcon 2021 wit one point. 45mins: Second Half start. Ivory Coast 2-0 Algeria. 45mins: Substitution for Algeria. Islam Slimani replace Said Benrahma. 48mins: Di Elephants dey press wit steady run from Sangaré enta Algeria box. 50mins: Aurier dey get plenty space on di right side. 55mins: Goal! Ivory Coast 3-0 Algeria. Pépé score better goal from di right afta e run enter Algeria box from di midfield. 59mins: Mahrez miss penalty. E play di ball hot bar. Algeria get penalty as Belaili goes down inside box. 61mins: Algeria get anoda chance wit a free-kick just outside di area but Mahrez play am go wide wide. 62mins: Substitution for Algeria. Bendebka replace Bennacer. 66mins: Belmadi dey vex wit as Ivory Coast players dey block dia passes. 69mins: Substitution for Ivory Coast. Die replace Sangare and Kanon replace Deli. 71mins: Ivory Coast win free-kick. Pepe play am go wide. 73mins: Goal! Ivory Coast 3-1 Algeria. Bendebka head ball enter net afta Mandi pass. 75mins: Anoda chance for Algeria. Slimani no fit convert di pass wey dem give am. 76mins: Ivory Coast Kessie hit ball enta net but referee say na offside. 77mins: Slimani don ginger Algeria wit continuous run into Ivory Coast half. 80mins: Zerrouki shot from distance deflect im fellow player. 81mins: Subsititution for Algeria Boulaya replace Atal and Benayada replace Belaili. 82mins: Algeria miss anoda chance! Sangare block Brahimi shot. 84mins: Pepe drive forward from right to left for anoda goal scoring attack but Algeria defender block am. 85mins: Substitution for Ivory Coast. Wilfried Zaha replace Pepe. 88mins: Ivory Coast dey ginger dia fans as match don dey finish. 90mins: Full Time. Ivory Coast 3-0 Algeria 1min: Kick off. Match don start 2mins: Bennacer start early Algeria attack on di inside-left. E win free-kick dangerous position afta a foul. 3mins: Mahrez free kick hit wall. 4mins: Ivory Coast Konan break go forward from left-back go inside Algeria penalty area before dem bring am down. No penalty. 6mins: Gradel carry ball wan attack but Ivory Coast players block am. 8mins: Ivory Coast chance! Konan collect pass from Gradel and shoot over di bar. 10mins: Behrahma carry ball run through di left and win corner for Algeria. 12mins: Booking. Yellow card for Ivory Coast Sergio Aurier. 13mins: Algeria win anoda corner. 15mins: Mahrez play free kick for Algeria but nobody fit control am. 18mins: vory Coast win free-kick for attacking position afta dem bring Pepe down. 21mins: Aurier concede corner to Algeria on di left. 23mins: Goal! Ivory Coast 1-0 Algeria. Kessie score afta pass from Pepe. 24mins: Pepe wey don dey busy since di game start, continue to worry Algeria. 25mins: Kossonou fall afta Benrahma put am under pressure. 26mins: Gradel win free-kick. 28mins: Algeria win corner on di right but nobody fit convert am. 31mins: Konan open tins up wit better skill on di left. 33mins: Algeria no dey press like team wey wan win. Na Ivory Coast continue to break into Algeria half especially from di right. 35mins: Algeria finally get chance wit ogbonge long ball from Mandi to Belaili but dem fit convert am. 36mins: Algeria win corner on di left. 39mins: Algeria dey try press wit long balls di Ivorians dey block dem. 40mins: Goal! Ivory Coast 2-0 Algeria. Sangaré give Ivory Coast dia second goal afta assist from Serge Aurier. 43mins: Keeper save weak shot from Belaili. Di defending champions hope don dey hang afta Ivory Coast second goal. 45mins: Half time. First Half don end Ivory Coast 2-0 Algeria. Ivory Coast: Badra Ali Sangare; Aurier, Kossounou, Deli, Konan, Ibrahim Sangare, Seri, Kessie, Gradel, Haller, Pepe. Algeria: M'Bolhi; Attal, Bensebaini, Bedrane, Mandi, Belaili, Zerrouki, Bennacer, Mahrez, Benrahma, Bounedjah. Make you dey refresh dis page as we go dey update am wit live reports of di match wey go start by 1600 GMT. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60070354 +entertainment David Ibiyeomie to Daddy Freeze 'insult' viral video, David Oyedepo and oda Nigeria big pastors wey top radio broadcaster don tackle "Daddy Freeze, di popular Nigerian broadcaster wey real name na Ifedayo Olarinde get old habit to always attack popular gospel preachers AKA 'men of God' for di west African kontri. On Monday September 7, Freeze enta news again afta popular Pastor David Ibiyeomie of Salvation Ministries for Port Harcourt, Nigeria, swear for am. Pastor Ibiyeomie say im no fit dey alive and Freeze go dey insult im 'papa', Pastor David Oyedepo. As e be so, pipo for social media don begin hala for Pastor Ibiyeomie sake of di kain harsh word wey im use curse Freeze. Bishop of Living faith Church Worldwide wey pipo sabi as ""Winners chapel"", David Oyedepo also follow for big big pastors wey Freeze don face. For September 2020, Bishop Oyedepo post for im verified Instagram page say di only way for marriage to dey fruitful na ""total submission from di wife"". Freeze counter am say submission na both ways, no be only for woman. Im add say wetin Bishop Oyedepo describe as submission sound like slavery to am. Founding Pastor of Christ Embassy, Chris Oyakhilome also chop yabbing from Freeze during dis coro era. Freeze wey call di pastor disappointment, say im teachings on di goment and 5G dey dangerous. Inside one YouTube video wey Pastor Oyakhilome release, im claim say federal goment order lockdown for Lagos and Abuja because dem wan install 5G network. Pastor of popular Lagos church and political aspirant, Reverend Chris Okotie enta di same trouser wit Freeze for August, 2020. Daddy Freeze bin tackle di pastor sake of one unverified message wey claim say Okotie no gree reopen im church for worship unto say im members no fit wear face mask as goment order. Di message claim say Okotie say for pipo to wear mask go church mean say dem dey deny di work wey 'Christ finish for di cross'. Freeze say for Okotie to even assume say one building na di church, na di same tin as to deny di work wey Christ finish for di cross. Freeze quote plenti Bible verses for di live YouTube broadcast to counter di pastor. Di 44-year-old ogbonge broadcaster na pikin to Nigerian papa and Romanian mama. Im bin grow up for Ibadan, Oyo state for southwest of di kontri wia im also go school for University of Ibadan. For 1996, Freeze start im radio broadcasting career for Broadcasting Corporation of Oyo State (BCOS), Ibadan before im come move to Cool FM for 2001." https://www.bbc.com/pidgin/54061253 +politics Ghana Speaker of Parliament: Lawmakers vote NDC Alban Bagbin as new leader "Opposition NDC Candidate, Alban Bagbin win Speaker of Parliament election for Ghana. Per declaration of de results, NPP dey control Executive arm of govment wey NDC dey control legislative arm of govment. NDC lawmakers bin dey inside jubilant mood ahead of de declaration of results afta de voting process to determine who go be next speaker of Ghana parliament end. Major tension bin dey for Ghana as NPP den NDC members clash over who go be de next Speaker of Parliament. After three attempts at voting since dem no fit reach decision as some members carry ballot box away, others kick de box den tins over secret ballot concerns. Armed military officials enter parliament to settle de matter but lawmakers insist dem for exit de chamber. Earlier, last minute ruling by one Cape Coast High court grant injunction against NDC Assin North MP-elect, James Gyakye Quayson from holding himself as MP elect. De court arrive at dis decision after petition filed by one Michael Ankomah who claim say de NDC MP-elect dey hold Canadian citizenship at de time wey he file en application to contest in de December election. According to de judge, Kwasi Boakye said during en ruling ""de NDC MP-elect for restrain from holding himself as Member of Parliament-elect for the Assin North constituency within de Central Region of de Republic of Ghana wey he no for present himself for swearing in as Member of Parliament-elect until de final determination of de petition."" De judge make dis ruling on Wednesday, January 6, 2021, few gours to de dissolution of de 7th Parliament, after around 12.01am on January 7, 2021 newly elected MPs go form de 8th Parliament under de Fourth Republic. Per dis ruling de NPP now get majority in parliament with 137 seats, while de NDC lose one seat which dey give dem 136 seats. De NDC MP-elect lawyers try file stay of execution against de court ruling but dem say de court clerks no dey post at de time dem arrive. Dis be some of de key things to note from January 6 to January 7, 2021 when dem go swear in President Akufo-Addo. On Wednesday 6th January 2021, Ghana go dissolve de 7th Parliament around midnight, dis dey follow Article 113(1) of de 1992 Constitution of Ghana. After de dissolution, around 12:01am on 7th January, de Elected Members of de 8th Parliament go gather for de Chamber of Parliament to elect a Speaker den Two Deputy Speakers. After dis, de new Speaker go swear in de newly elected Members of de 8th Parliament. In de morning of de 7th January, 2021 dem now for swear in President elect, Nana Akufo-Addo before de newly constituted 8th Parliament. De decision of who go be Speaker of Parliament make sketchy because of de number of seats both NPP and NDC get each for Parliament. Sake of dis, wen it comes to de voting for new Speaker, political analysts dey talk say dis be difficult issue. De NPP wan bring back Professor Mike Oquaye, who be Speaker of de 7th parliament wey one of de people de NDC wan nominate as speaker be former NDC majority leader, Alban Bagbin. However, de NPP be hopeful say when it comes to voting, de one independent candidate for Fomena who previously be NPP lawmaker go vote give dem. Members of de 8th Parliament go vote for Speaker, First Deputy Speaker, den Second Deputy Speaker of Parliament. After which de newly elected speaker who de 275 members vote for through secret ballot, go now swear de new members in as lawmakers for Ghana. On January 7, 2021 dem go swear in President elect Nana Akudo-Addo before de 8th Parliament in accordance with Article 57(3) of de 1992 Constitution of Ghana. After de swearing in happen, de President go fit start en duties as head of state by appointing ministers den things who he go work with." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55559407 +entertainment Big Brother Naija 2022 housemates: Ex-Miss Nigeria, pharmacist, hype-woman, meet di BBNaija level-up housemates "Di bell ring and you go know say na dat time of di year wen most young pipo go dey stuck to dia televisions and mobile devices for over 70 days watching as oda young pipo dey participate for di season 7 of di Big Brother Naija reality show. Di housemates dey compete for a grand prize of N100M and perhaps dis na why di show dey always create so much buzz year in year out. Over di years, many Nigerians don criticise di show and many continue to see di show as ""distraction"" and something wey no dey add value to di society. In 2019, one Islamic human rights organisation, di Muslim Rights Concern, Muric bin ask di Federal goment of Nigeria to ban di show. Muric Director, Prof. Ishaq Akintola bin describe di show as ''abomination'', ''exhibition of nudity'' and ''invitation to chaos and insecurity'' becos e dey allegedly mislead di young pipo. Fans of di show most times no dey mind wetin oda pipo dey tok about am as di show dey always carry on despite di condemnation. Dis time around and wit di 2023 general election for Nigeria around di corner, pipo dey caution di young pipo, make dem no allow di show distract dem. E dey debatable weda or not di show don 'distract' anybody as some believe but young pipo wey don appear for di reality TV show don also see am as opportunity to live dia dream. Especially for Nigeria wey di number of unemployed youths dey high. Di seventh edition of di show wey dem tag ''Level Up'' return wit im first-12 housemates on Saturday and fans dey expect di remaining housemates on Sunday evening. Like evri season critics don begin chook mouth about di show while fans don already begin dey choose dia faves. Dis na all di 24 housemates wey don enta di house; Ex-miss Nigeria, Beauty Etsanyi Tukura na 24-years-old lawyer from Taraba state. She tell her oda housemates say she dey passionate about advocacy. Groovy na 26-years-old fashion entrepreneur and model from Anambra state. Ilebaye Odiniya, 21, na graduate of criminology and security studies. 22-years-old Daniella Peters na poet who also dey act. Cyph real name na Bright Hidi Nwekete. Im na Electrical Engineering graduate from Imo state. Saviour Ikin Akpan aka Pharmsavi na licensed pharmacist from Akwa Ibom state. Phyna wey her real name na Ijeoma Josephine Otabor na edo-state born actress, She say she dey also dey do hype-woman for clubs. Keseina Tony Adjekpovu alias Kess fit be one of di oldest housemates dis season. Di 28-years-old businessman say im wife bin don give am permission to participate actively for di show. Chiamaka Crystal Mbah aka Amaka na 23-years-old Anambra state born health care worker. Khalid Ismail Ahalu na 22-years-old university undergraduate wey enjoy archery, skateboarding and basketball among oda tins. 22-years-old Brian Chkuwuebuka Chiji aka Bryann na singer and songwriter. Christiana Oluwafunke Ojumu alias Christy O na 24-years-old beauty entrepreneur from Ondo state, southwest, Nigeria. Meet Sheggz. Im na professional footballer and ""lover of Goosebumps."" Shey you like to dance? Chi Chi na your girl. She be exotic dancer. Oya meet Hermes, e call imsef ""proud boyfriend of two."" Meet Diana! Just check her out. Giddyfia na di latest housemate to enta di BBNaija season 7 house. Im say im dey here for di game and also, e no go mind carry any girl wey catch im eyes for di house dey go. Chomzy na di next to enta house. She say na di money carry her come. N100m! And here na Dotun. Dotun plan to make di house catch fire. im promise to you be say, ""im go bring a lot of hotness!"" Meet Allysyn! She dey excited to come Big Brother Naija Season 7 and she dey curious! Here come Adekunle. Adekunle na Lasgidi man and im carry Lagos swags plus wahala come you land your domot for di next 70 days. Doyin na smart multitasker. Watch out for her, she ready to give gbas gbos wen e necessary. Meet Eloswag, im na dancer and im dey single, ready to mingle, but im no ready for relationship o! Dis na Bella! She like her space even as she come compete for di big prize of N100m Di organizer of di show over di years don describe as not only entertaining but also educating. Season 1 Katung Aduwak Season 2 Efe Ejeba Season 3 Miracle Igbokwe Season 4 Mercy Eke Season 5 Olamilekan Agbeleshe Season 6 Hazel Oyeze Onou" https://www.bbc.com/pidgin/62285260 +politics US elections 2020: See di times presidential results delay don shake America We don dey wait for days now make di US presidential election result comot, and for many pipo - even if dem no be citizens - di mata don already begin tire dem. But so far, e no compare to anoda election wey sabi pipo believe say na one of di hottest election wey two presidential candidates don drag, for US history. E pass one month, or 35 days if we wan dey exact, for di 2000 president election results to comot. In fact, di mata hot so tey e take di Supreme Court - di highest court in di land - to declare republican George W Bush as di winner. Di only time court don decide winner for America history. On election day, 7 November, Democrat candidate Al Gore bin win di popular vote, but di vote scores from Electoral College come dey too close together. Di race tight so tey, dem need to do recount. Gore team demand say make four counties (like local goments) use hand do di recount one by one but Bush and im pipo hala say lai lai. Weeks later, on 12 December, di Supreme Court rule in favour of Bush to carry am enter White House. But even dis Bush-Gore drama no reach America longest results delay. Dat one happen for di 1876 election, wey use almost 4 months to finalise - currently di US record. Di election happun on 7 November and dem no decide di result until 2 March 1877, just few days before inauguration. Republican Rutherford Hayes na im dem declare di winner wit just one electoral college vote wey e take gap Democrat Samuel Tilden. Dat one too require dem to bring one committee wey no dey partial to help dem settle di mata. E fit shock you say even dis kain wait fit happun for America; After all dem say na dia democracy advance pass for di whole world. Take Nigeria for instance, results from di hot 2019 presidential election contest between president Muhammadu Buhari and Atiku Abubakar come out within 4 days. https://www.bbc.com/pidgin/world-54854623 +politics Ghana Elections 2020: NDC minority MPs and Ghana Electoral Commission face off update "Electoral Commission of Ghana [EC] say de reason why dem fail to take de petition from NDC minority members be sake of dem no notify then on time. Inside press statement wey de EC release to address dis issue, dem explain say de minority only submit letter on Tuesday morning. Dem explain say even de time de minority letter come, de time be 10.08am meanwhile dema time for de presentation of petition be 10.00am. Inside statement wey EC release, dem explain say since dem no get de letter to notify dem on time, de EC Chairperson den team no dey de office to receive de minority. ""If like dem notify de Electoral Commission proper about dema presentation, de leadership go be present to receive dema petition"" de EC statement explain. Minority MPs for Ghana on Tuesday march go de premises of de EC to submit petition about de 2020 election results den outstanding issue on Techiman South. Dem enter stand off plus Ghana Police Service who no allow dem to submit de petition. EC explanation about why dem no fit rake de petition dey bore some Ghanaians who feel say de Commission no do well." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55408045 +politics Constitution review in Nigeria: Senate wan review 1999 Constitution - How e involve you Nigeria Senate wan review di 1999 constitution. Dem go begin wit zonal public hearing for di six geopolitical zones later dis month. Dis move na to adjust di kontri law book, Senate Committee on di Review of di 1999 Constitution tok for statement. Many pipo inside di west African kontri don argue say di 1999 constitution wey dey govern Nigeria no dey work well. Di Public hearing go hold for for 12 state capitals at di same time as centres. E mean say two centres for each geopolitical zones go hold public hearing from Wednesday, 26th May to Thursday 27th May. E dey free to attend to di general public according to di statement wey di Deputy Senate President, Ovie Omo-Agege sign. Na sixteen main issues dem dey follow tok for inside dis public hearing. Na here di mata involve you to go tok your own ontop di following: Jos Centre go represent Plateau, Nasarawa and Benue Minna Centre - Nigeri, Kwara, Kogi and Abuja Bauchi Centre - Bauchi, Yobe and Borno Gombe Centre - Gombe, Taraba and Adamawa Kaduna Centre - Kaduna, Kano, Jigawa and Katsina Sokoto Centre - Sokoto, Kebbi and Zamfara Owerri Centre - Imo and Abia Enugu Centre - Enugu, Ebonyi and Anambra Asaba Centre - Delta, Edo and Bayelsa Port-Harcourt Centre - Rivers, Cross River and Akwa Ibom Lagos Centre - Lagos Oyo and Ogun Akure Centre - Ondo and Osun Before dis process begin, many experts don tok say 'na restructuring fit solve di plenti palava wey dey face Nigeria'. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57086402 +sports Cameroon vs Egypt prediction: Team news ahead of Africa Cup of Nations semi-final fixture "Cameroon and Egypt don set for lock horns for semi-final game for 33rd edition of Africa Cup of Nations for Olembe stadium. De two teams go square off for de semi-final on Thursday with their eyes on another title for de Africa Cup of Nations. Ahead of de fixture, de two teams don engage in war of words wey start as de two teams qualify for semi-final. 'De next match na war and wuna get for bi ready for war, na so former Lions' captain, now president for Fecafoot, Samuel Eto'o Fils bin tell de Lions for encourage dem. But, Egyptian Coach no laik dis Eto'o Fils e tok for players. Carlos Queiroz say no bi war and say make Eto'o Fils take back de words. ""Ah no fit komot for dis kontri weh ah no take de trophy, Captain for Pharaohs, Mohammed Salah too declare. De match go take place for de Olembe stadium wia eight pipo bin die for stampede wey happun on 24 January wen Cameroon beat comoros for round of 16. Cameroon and Egypt don win Afcon 12 taims combine - seven for Egypt and five for Cameroon. Di two countries know each other well well and go meet for 11th taim for Afcon, more dan any other teams. Egypt don win dia last four Afcon games against Cameroon and deh score nine goals. Cameroon win for seven of de nine semi-final games weh deh play for Afcon while Egypt dey lead Cameroon as deh pass semi-final stage eight taims. Cameroon eliminate Egypt for 2006 Afcon semi-finals wen dem beat dem 2-1. Egypt go play without dia key central defender Ahmed Hegazy weh e get injury. Also, Marwan Mohamed Moustafa Dawoud chop suspension and no go play. Meanwhile nobody dey injured or dey out for Camroon for dis match. Christian Bassong, former Cameroon international say na tough game. Na game weh e depend on coach dia tactics and if players put de strategy for practice deh go win. But ah check say Cameroon go win Egypt 3-2." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60241071 +business Nigeria Federal High Court hold foreign nationals for alleged piracy, oil theft "Di Ministry of Defence don arraign some foreign sailors for di Federal High Court for Port Harcourt, di Rivers State capital, Southern Nigeria for piracy and crude oil theft. Dis dey come after di Nigerian Navy arrest 26 sailors from di vessel wey dem gbab for Equatorial Guinea for alleged piracy and crude oil theft from Akpo Oil Field, Bonny for Rivers State. Di 26 suspects wey from India, Sri Lanka, Philippines and Poland dey face charges wey border of: Na only 16 of di suspects appear before Justice Turaki Mohammed of Federal High Court Port Harcourt and dem plead not guilty to di charges. Di court say dem go remain for di Nigerian Navy and adjourn di mata to Tuesday 15 November wen di remainng 10 suspects go come take dia plea. Nigerian Navy bring back a runaway Very Large Crude Carrier, VLCC, MV HEROIC IDUN dem arrest for Equatorial Guinea becos e unlawfully enter Akpo Oil Field Bonny, Rivers State to illegally lift crude oil. Di Nigerian Navy mobilize about five ships including NNS IKENNE and NNS OJI run di operation for voyage wey take dem eight days to and fro. Dis na afta ogbonge diplomatic negotiations wit di two kontris. According to di Chief of Policy and Plans, Naval Headquarters, Abuja, Rear Admiral Saidu Garba, dis Very Large Crude Carrier VLCC, MT HEROIC IDUM with length 336 meters, 60 meters width and 11 metres draught, with IMO number 9858058, dey registered for Marshall Island and get capacity to carry over two million litres. Di vessel enta Nigerian waters say dem wan lift crude oil around Akpo deep offshore Bonny for midnight of 7 August 2022. But di Nigerian Navy Maritime Domain Awareness facility sight dem and ask weda di VLCC get legitimate presence for di Akpo Field wey Total SA dey operate. Dem later find out from di controlling agency, NNPC Ltd, say di vessel no dey cleared. So dem deploy Nigerian Navy Inshore Patrol Craft, NNS GONGOLA, to investigate am. Dem discover say di vessel no get both NNPC approval and Naval clearance and so dem instruct di vessel to proceed to Bonny anchorage for further instructions. But captain of MV HEROIC IDUN no gree follow instructions and say dem tell am not to take directives from di Nigerian Navy Ship. E go di direction of di Sao Tome and Principe maritime area. Na as dem sail enter di Nigerian-Sao Tome and Principe joint Development zone into Equatorial Guinea, di Nigerian Navy go arrest am. “Di Nigerian Navy assure Nigerians say with dia statutory responsibilities and from di strength of di strategic directives of Chief of Naval Staff, Vice Admiral Auwal Zubairu Gambo, di Service go maintain zero tolerance to crude oil theft and oda criminal activities for our maritime domain. Rear Admiral Garba say e no happy with di level of economic sabotage oil theft don cause di kontri. Di vessel currently dey held at Luba Anchorage in Bioko Island, Equatorial Guinea wia di kontri dey also conduct her own investigations while we await diplomatic procedures for handing over to di Nigerian Navy."" E add. No be only say dis MV HEROIC IDUN wan kolobi oil comot Nigeria dem even report Nigerian Navy vessels say, dem be pirates. Rear Admiral Saidu Garba na im reveal dis one say, di Captain broadcast false piracy attack call to IMB Piracy Reporting Centre to mislead mariners say NNS GONGOLA na pirate vessel and to forge alibi for dia desperate action. Di Chief of Policy and Plans NHQs say dis false information na slap on di integrity and reputation of Nigeria. becos Since 2021, dem never record any pirate attacks within Nigerian maritime environment and dis naim make di International Maritime Bureau to comot Nigeria from di list of piracy prone countries for March 2022. Di mata of oil theft don keep Nigerian navy busy over time. For October 2022, Nigerian National Petroleum Company Ltd (NNPCL) and some Security Agencies on Monday destroy one of di biggest oil vessels dem arrest with crude oil wey dem allegedly tiff from Escravos Pipeline for Delta State, Southern Nigeria. Dem arrest di vessel, MT Deinmo, with IMO number 7210526, last week for di Niger Delta creeks with seven crew members on board. Na di private Security outfit Tantita security wey ex-militant leader, Government Ekpemupolo, (alias Tompolo) own and wey di NNPCL dey use do pipeline surveillance, na im catch di vessel wey bin dey loaded with di stolen crude oil. Dem catch dem as dem dey pump di crude directly from di Escravos Pipeline into dia vessel for Warri South West LGA, Delta state and dem don hand over di arrested crew members to di Joint Task Force JTF for 3 Battalion Nigerian Army, Effurun near Warri. Di matter of crude oil theft na one ogbonge challenge wey dey worry di Nigeria economy as dat na di main revenue earner for di kontri wey dem even dey use plan di annual national budget. Crude oil theft don reduce di production capacity wey di Organisation of Petroleum Exporting Countries OPEC give Nigeria, wey also don negatively affect di revenue of di kontri. Dis join with di bad effect e get on environmental pollution wey be say now most of di aquatic life don spoil finish and many rivers for di Niger Delta don spoil finish." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn0yrqkkx3vo +entertainment Jada Pinkett Smith Red table talk: Full details of Jada Pinkett tok on why ladies need to communicate dia sexual expectations wit dia partner "Jada Pinkett Smith don ask pipo to stop dey make up headlines about im sexual relationship wit husband Will Smith. Di actress dey respond to reports wey dey claim say she bin to say get issue for bedroom with Will. ""Just because say I get time today. Stop dey make up headlines. Will and I neva get any issue for bedroom. Thank you"", she address di mata for one Tweet. Jada Pinkett marriage to Will Smith become topic of discussion on top social media again afta her recent Red Table Talk wit American actress, Gwyneth Paltrow and her mama, Di ladies bin discuss why e dey important for women to clearly communicate dia sexual expectations wit dia partner and Smith contribution to di subject go make pipo suggest say she 'no get healthy sex life wit Will Smith' Some fans even call her out social media say she dey ""continuously embarrass her husband"" Di topic of dat Red Table Talk episode na 'sex' and wen dem begin tok about di subject of accountability for bedroom, Jada discuss her own experience. ""You bin bring up sometin and I think say e dey supremely, supremely important and dat na di idea of accountability,"" Smith tell her guest for di show, Gyneth Paltrow. ""Say we suppose fit dey able to speak up wen tins no dey go well, wen tins dey go well, but dat level of accountability wey actually bleed through our entire life."" ""Sometimes for women, for us, dat na very difficult subject to talk about, accountability,"" she add am. ""E dey hard,"" di actress explain. ""I mean, di thing Will and I talk about a lot na di journey. We start in dis at a very young age, you know, 22 years old. Dat na why di accountability part really hit for me because I think you expect your partner to know wetin you need], especially wen it comes to sex. E be like, 'Well if you love me, you suppose know. If you love me, you suppose read my mind.' Dat na huge pitfall!"" Jada feel say she don since ""grow out of am"" and admit say she know say di best way to communicate na to dey direct and ""I know say I dey accountable to do di same."" Wen Paltrow ask her if she dey accountable to her partner, Jada reply say: ""I really dey try! E dey uncomfortable, but e dey deeply healthy and I think around sex because na something wey we no dey really talk about E get so much fantasy around am."" She also agree wit her co-host and mama Banfield-Norris, wey tok say in her opinion pornography na large cause of unrealistic sexual expectations for relationships. Dis no be di first time wey Jada relationship don become topic of discussion for internet. For July 2020, di actress bin reveal for di same Red Table Talk how she bin cheat on her husband wit singer, August Alsina. Di actress claim say she bin don separate from Will Smith at di time dia friendship became romantic. At dat time, di couple say dem decide to separate to figure out how to make demsef happy and at dat time dem bin even tink say dem don dey ova." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59093571 +entertainment BBNaija Lockdown Reunion 2021 update: Laycon/Erica episode highlights for BBNaija reunion "Erica Nlewedim go finally show face for di Big Brother lockdown reunion show. Di reunion show wey start for June 17 don reveal many shocking moments from di lockdown season five housemates. From romance to fight, these sets of housemates no dey hide anything at all. So wetin go happun for Monday episode of di show? Monday episode go address di biggest fight of di Lockdown season between Erica and Laycon. And also to find out wetin di two parties wey bin dey involved think about di mata now wey dem don comot for di house. ""I feel say im be snake (laycon) im go make pipo pity am… no point, no relevance""... Erica tok ""And I no go ever trust anything wey comot from im mouth"" Erica add put. Na dat fight end Erica journey inside Biggie house wey Laycon eventually win. Fans go get to find out for demsefs, wetin Laycon tok when dem show di episode later tonight. Na cable company DSTV dey show di ""BBNaija Lockdown Reunion"" for African magic Urban at 10:00pm. And at 10:30pm on AM Family from Mondays -Fridays. Organisers say di four things to expect from di Lockdown Reunion na For di first time for di Big Brother Naija Reunion history, every single Housemate for di Lockdown Season go attend. E get more love triangles and squares than wetin pipo fit imagine According to Big Brother, di biggest clash come from two supposed friends and di first reconciliation come from two longtime enemies. Di show host, Ebuka mention say e get more than one few jaw dropping moments. And even di Housemates dey shocked to find out how much dem no really sabi each oda, Ebuka add. BBNaija Reunion Show na part of preparations for di commencement of another season of di reality show. And fans go once again get to see dia favourite 'Lockdown geng'." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57641870 +entertainment Ada Ameh last post, interviews before her death and how Nigerians dey react "Nigerians dey react to di death of popular Nollywood actress Ada Ameh. President of di actors guild of Nigeria, Emeka Rollas confam give BBC Pidgin on Monday, 18, July, 2022 say, ""we confam say she don die."" Although no official confirmation on di cause of her death yet, her death come as a shock to many Nigerians as e dey happun just two years afta di death of her only pikin, Aladi Godgift Ameh wey die for October, 2020. Many pipo no gree believe at first di tori of di death of di ogbonge actress wey don feature for many movies including comedy series. Especially as e come suddenly, just afta wen she post for her social media accoun less dan 24 hours before di announcement say she die. Inside di post wey get di time post, 'Sunday 12:53pm', Ada Ameh dey wit friends and be dey enjoy a local delicacy of di Urhobo pipo, for Delta state Nigeria, Ovwho soup. ""I no go lie for you, dis one wey we come so na enjoyment galore,"" Na so she tok for inside di video. Nigerians don take to social media to react to her death. Di tori of her death dey top di trends for di kontri. Veteran actor Hilda Dokubo post for her Instagram account say di tori of her death leacve her in tears and extreme pain, ""Dis hurts oh."" She tok. @SirLeoBDasilva post say, Rest in peace Ada Ameh. You bring joy to all of us wit your talent. Anoda social media user, @harrisonJNIOR say, She give us di wholesome meme, not to talk about oda lives she's impacted physically and through her skills, may her soul rest in peace Ada Ameh @raycypherSf say, Thanks for making our childhood memories joyous, entertaining, laughable and above all, something to tell children about. May your loving and amusing soul rest in peace, Ada Ameh. Aladi Godgift Ameh die on October 2020 afta one surgery she do. According to Ada, Aladi bin sick and wen she go hospital, doctors say she need to do surgery to check if tumour dey grow. Di surgery dey successful and dem even tok di day afta di surgery. She say she tink say God show her how heaven look like and she decide to stay. Aladi be 32 years old wen she die. Since den, life bin no dey easy for late Ada Ameh according to wetin she tok for interviews. Barely one year afta di death of Aladi, Ada say she still dey try to move on as her death na one tin wey really shake her. ""Sometimes I go just sit for my bathroom dey reason wetin I dey do, wetin remain, wetin dey next for me."" Ada Ameh tok inside interview with media personality Chude Jideonwo for 2021. To cope den, she bin struggle wit alcohol, she tok. She bin say most nights she still dey cry as her death still dey very painful. Den she bin tok say, wit God and wit di support of family and friends, she dey heal. For early July , late Ada Ameh bin show for one TV programme on TVC wia she tok about how she bin dey deal with mental health wahala. She explain say na di death of her daughter for 2020 wey be her only pikin make di mental health mata worse. Ada Ameh explain say, ""we bin grow togeda, I be 14 years old wen I born her, so she be like my younger sister"". She be my best friend, I just see my world crumble afta I lost her, she tok. She further explain how she don already bury seven family members wit her daughter death to make am eight pipo. ""I don lost three of my sisters before dat time, each of dem get like three pikins each, I lost like three of my brothers and my father""....I bin tink say I go be next bifo my daughter die for 2020. ""I fit cry for days and I bin dey in and out of hospital, she tok for di interview. Dem born Ada Ameh for May 15, 1974 and she come from Benue state. Ada Ameh don dey di Nigeria Nollywood industry for more dan 25 years and she start her career wit di blockbuster movie, Domitilla. She don feature for several movies wey include Oloture, 30 days in Atlanta and many odas. She be di current lead role player for one Nigeria sitcom program on DSTV, ""The Johnson."" Ada na advocate for girl child development project and don receive accolades within and outside di kontri for excellence. She bin born her daughter wen she be 14 years old. Na di same month she get belle her parents separate." https://www.bbc.com/pidgin/tori-62211186 +sports Atletico Madrid vs Man City highlights: Manchester City set up ogbonge semi final match wit Real Madrid Manchester City don set up ogbonge semi final match for di Uefa champions league wit Real Madrid. Dis na afta dem hold off Atletico Madrid to a 0-0 draw for di second leg of dia quarter final game for Spain. City keep dia cool and play wit plenty composure through di game even though Athletico show dia sef for second half. Ilkay Gundogan for end di game easily for di English side if to say e score one close range shot but Oblak save am. Atletico end di game wit 10 men wen defender Felipe chop im second yellow card for a dangerous foul on Phil Foden. 46 mins - Di hosts, Atletico Madrid don restart play. 50 mins - Atletico don mount for City half, dem need a goal but so far e no clear wia e go come from. 57 mins - Anton Griezmann shot go very close to open di scoring. Ederson stretch to stop am but di shot go wide. 65 mins City make dia first substitution afta De Bruyne get injury. Di Belgian dey replaced by Raheem sterling. 67 mins - Anoda City player don injure, dis time na Kyle Walker. But e look like im dey try see if e go kontinue. 69 mins - Substitution Renan Lodi, Koke and Griezmann don come off, Koke, Rodrigo de Paul and Angel Correa don enta di game. 70 mins - Only one minute afta im come on, Rodrigo de Paul fire shot wey go past di right post. 73 mins - Substitution for Man City. Wlaker no fit continue, Nathan Ake don replace am. 77 mins: Substitution for Man City. Fernandinho enta for Bernando Silva. 80 mins: Llorente chop go miss Athletico next match afta e chop yellow card for foul. 83 mins: Substitution for Athletico. Suarez enta for Lemar and Gunha for Jao Felix. 85 mins: Man City don dey press Athletico. Dem don spen more time for dia half in di last 5 mins. 86 mins: Na small time remain make di game end and both teams don suddenly begin press. 87 mins: Man City goalkeeper Ederson make crucial save afta ogbonge shot from Corea. 89 mins: Di game don dey on hold afta Filipe kick Foden wey make Man City players vex. Di situation dey rowdy. 90 mins: Athletico defender Filipe don chop Red card for di foul on Foden. Savic also get yellow card. Nathan Ake of Man City for pushing Savic. 90 mins +: Officials don add 9 extra minutes sake of di incident. 96 mins: Athletico goalkeeper Oblak save one -on one shot from Gundogan. 97 mins: Cancelo chop yellow card for poor challenge on Carresca for di edge of Man City 18 yard box. 98 mins: Ederson save last minute free kick from Athletico. E hit am go throwing. Full Time: Atletico Madrid 0-0 Manchester City. 1 mins - Di match don start. 4 mins - Atleti break into City defence wit crose from Lemar, Walker clear di ball. 10 mins - Kevin De Bruyne cross corner and John Stones nod di ball, but e go just over di bar. 13 mins - Phil Foden need treatment, e be like say im go kontinu. 18 mins - City goalkeeper Ederson rush out to head clear one long pass wey threaten di City defense. 24 mins - Yellow card for Felipe. 30 mins - Ilkay Gundogan control good pass inside di eighteen yard box, but im effort hit di post. Im rebound and anoda shot dey blocked. 34 mins - Phil Foden dribble im way past some Atleti defenders but im run into traffic as e later lose di ball. 36 mins - Di game neva get any real chance since dat Gundogan shot hit di post. 38 mins -Atletico Madrid need one goal to equal di tie as dem still dey lose on aggregate. Half time Atletico Madrid 0-0 Manchester City Atletico Madrid XI: Oblak; Llorente, Savic, Felipe, Reinildo; Lemar, Kondogbia, Koke, Lodi; Griezmann, Joao Felix. Man City XI: Ederson; Walker, Stones, Laporte, Cancelo; Bernardo Silva, Rodri, De Bruyne; Mahrez, Gundogan, Foden. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61101249 +sports Samuel Takyi: Tokyo 2020 Olympics medal dey guaranteed for Ghana boxer, dia first Olympic medal since 1992 20-year-old Samuel Takyi don end Ghana 29 year wait for Olympic medal. E sure for Ghana as Takyi beat Colombia David Avila Ceiber for di featherweight boxing division of di Tokyo 2020 Olympics to get sure place for di semi-final. Na from di back wey Takyi take win 32-year old two-time Olympic Colombian champion on a 3-2 split decision victory for di early hours of Sunday. As e secure dis semi-final spot, Takyi dey guaranteed of at least bronze medal before e go take on American Duke Ragan for dia semi-final fight on Tuesday, August 3. Dis one na because for boxing for di Olympics, both di pesin wen win and loss go get bronze medals. Dis go be Ghana first Olympic medal since di Black Meteors win bronze for di 1992 games for Barcelona. And di first boxing medal since middleweight Prince Amartey wey take bronze for Munch in 1972. Takyi join Ghanaian Olympic greats Clement Quartey, wey be light welterweight wey win silver for Rome for 1960, Eddie Blay, bronze light welterweight medallist from Tokyo 1964 and Prince Amartey wey make history for Munch in 1972 Ghana gold-medal threat Samuel Takyi go fight Duke Ragan from USA on Tuesday 3 August 2:30am Ghana time. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58045950 +entertainment BET Awards 2019: Burna Boy win Best International Act Nigerian singer Burna Boy don carri di ogbonge 'Best International Act' award for di 2019 BET Awards wey happun for America. Dem nominate di singer along wit oda top musicians from around di world like Mr Eazi, AKA from South Africa and Giggs from di UK. Burna Boy mama Bose Ogulu, wey also be im manager accept di award on im behalf. For her speech she tok say Burna Boy want make every black pesin know sey dem be Africans first before dem be anything. Burna Boy wey announce di return of im Africa Giant tour for America, say im win di award for Africa. Di BET Awards also give late rapper Nipsey Hussle Humanitarian Award for di work wey im do to help pipo wey dey gang before im die. Cardi B collect di album of di year prize, Tyler Perry carri Ultimate Icon Award and Rihanna present wit di Lifetime Achievement Award. https://www.bbc.com/pidgin/tori-48741721 +entertainment BBNaija Nominated housemates today: Queen, Saga, Liquorose, Whitemoney, Jaypaul, Sasky and JackieB dey up for eviction "Seven housemates dey up for possible evictions dis week afta Monday evening nomination and Head of House games. Before di head of house games na Pere, Saga, Emmanuel, Liquorose, Whitemoney, Jaypaul, Sasky and JackieB bin dey up for possible eviction.. But Biggie, give dem one opportunity to remove themselves from di list during di Head of House games. Emmanuel and Pere na di lucky ones wey take advantage of di opportunity for di new twist wey Big Brother introduce to di game. Emmanuel win di Head of House game and get automatic Immunity to comot for di list of nominated housemates e choose Liquorose as im deputy wey go stay wit am for di luxury louge. While Pere wey carry second and get di Save and Replace Power, Replace himself wit Queen. As tins be now na, Saga, Liquorose, Whitemoney, Jaypaul, Saskay, Queen and Jackie B dey up for Eviction dis Sunday. Roselyn AKA liquorose She be 26 years old from Edo State. She be popular Nigerian dancer. She saye she don dey dance since she be 12 years old. Roselyn say she dey bring her playful self to di competition. Saskay 21 year old from Adamawa State. She say she be peace loving pesin and she say she be emotional pesin. Sakay na Artiste and Model.She say she go like own her own Art gallery afta di show. Saskay dey in a relationship. 29 year old from Adamawa state. Jackie B She be single mother of a son and she say she come from a family of 12. ""You respect me I respect you"" na her watchword. She say she love music, dancing and having fun. Saga Dis 28-years-old engineer come from Lagos State. Okusaga aka Saga say im go ""bring vibe to di house"". Im say di lowest point for e life na wen im hear say e mama - wey im describe as e best friend - don die. Whitemoney Im say e be businessman wey dey into import of shoes. Multitalented Whitemoney describe imself as open-minded ""jolly good fellow"" wey like to catch fun. Di 29-year-old Lagos based Whitemoney originally come from Enugu State. Jay Paul 29-years-old Jay Paul come from Calabar, Cross River state, e describe imsef as ""social butterfly"". Im be complete entertainer wey dey run tourism business. Jay Paul dey act, sing and dance as well. So now, na only six housemates no dey up for possible eviction and dem be Angel, Yousef, Cross, Pere, Nini and Emmanuel. At least one of di nominated housemates go leave Big Brother house on Sunday." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58466318 +sports Nigeria vs Sierra Leone: [When is Nigeria vs Sierra Leone?] Super Eagles team list for Afcon qualifiers "Nigeria Super Eagles coach, Gernot Rohr, and Napoli striker, Victor Osimhen, don beat dia chest say Nigeria go win di 2021 Africa Cup of Nations qualifying double-header against Sierra Leone. Osimhen wey arrive di Eagles camp from im base for Italy on Wednesday say im dey happy to come back to join di squad. ""Make Nigerians dey expect nothing but victory but to be realistic di game no go dey easy so we need to prepare well which we don dey do and we go give our all for dis win,"" na so di striker tok according to local sport tori pipo. Nigeria go host di Leone Stars for di Samuel Ogbemudia Stadium, Benin City, Nigeria, on Friday by 5pm Nigerian Time. Di Super Eagles team list neva dey clear but coach Rohr say dem no dey underrate Sierra Leoneans. Di Nigerian Natonal team get focus and dia objective na to win di game on Friday. ""We wan win di two games so we fit get ticket and be little more relaxed for final games,"" Gernot Rohr tok. Di last match wey di super eagles play dem feature many young new players. However dis time around tori from di training camp show say top international stars wey dey play for Super Eagles don show. See list of Super Eagles players wey dey camp for Benin City dey train: Ahmed Musa William Ekong Alex Iwobi Ola Aina Joe Aribo Leon Balogun Kevin Akpoguma Sebastin Osigwe Zaidu Sanusi Tyronne Ebuehi Etebo Oghenekaro Maduka Okoye Ike Ezenwa Chidozie Awaziem Kelechi Iheanacho Emmanuel Dennis Chidera Ejuke Samuel Chukwueze Paul Onuachu Football na luck sometimes as game fit change and kontri wey one no expect say go win fit carry trophy. However, sometimes history of di kontri for pas fit help person make informed guess about who fit win. Di two kontris don play for 14 times and na Nigeria get upper hand. Nigeria don win 9 of di games. Di last ggame wey dem bin play end for 2-1 and na Nigeria get di 2. Nigeria bin play 1 - 1 draw with Tunisia for dia last group game on 13 October. Di Super Easgles even lost to Algeria four days earlier wen day jam Algeria on 9 October. Anoda reason wey Nigeria get upper hand na say na for Samuel Ogbemudi dem go play di game wey go give Nigerian players more confidence. Also, na ontop dia field and dem dey familiar with di way dia field be. Also, Sierra Leone dey behind Nigeria for for global ranking of FIFA. Nigeria rank 32 best team for di world but di Leone star dey 102. Nigeria also be di fourth0best for di world while Sierra Leona dey 31st." https://www.bbc.com/pidgin/world-54914108 +politics African leaders wey don tay for power Equatorial Guinea President Teodoro Obiang Nguema wey don dey power since August 1979, na di leader wey don tay pass for power. Before now, di person wey follow Obiang na Zimbabwe former president Robert Mugabe, wey don rule di country since independence for April 1980 but im resign on Tuesday. When im be president, Mugabe bin get record for di leader wey old pass for di world, im be 93 years old. Teodoro Obiang Nguema - Equatorial Guinea - 38 years Im become leader on August 3, 1979, after coup wey comot im own uncle, Francisco Macias Nguema, wey dem kill for firing squad. Paul Biya - Cameroon - 35 years Im become president on November 6, 1982 after e do seven years as prime minister. Denis Sassou Nguesso - Congo - 33 years Im first serve as president from 1979 to 1992 and later after di civil war im come back to rule for 1997. Yoweri Museveni - Uganda - 31 years Im become Uganda leader on January 1986 after im win di war to comot Idi Amin Dada. Omar al-Bashir - Sudan - 28 years After coup wey im lead, Al-Bashir dey rule since June 1989. Idriss Deby - Chad - 27 years Im don dey power for di north-central African country since December 1990. Issayas Afewerki - Eritrea - 24 years Di head of state don dey power since 1993. https://www.bbc.com/pidgin/tori-42069533 +entertainment GoFundMe Erica: How fans dey support Ngozi Nlewedim wey BBNaija TV show disqualify "Fans of big brother housemate, Ngozi Nlewedim AKA Erica don begin try raise $100,000 for her afta organizers of di reality TV show disqualify her yesterday. Di Loyal fans of Erica don quick-quick go set up GoFundMe account and at present 171 pipo don donate $14,738 and di amount dey likely to increase as more fans still dey contribute. Apart from di GofundMe, One car dealer, Chidi Mike wey be strong fan of Erica don promise to dash her N2m cash and post foto of motor wey her picture dey inside. E write for im Instagram handle say: ""Disqualified or not you be still my winner. N2 million cash money waiting for you."" Big Brother bin disqualify Erica afta she collect her third strike for her behaviour towards her fellow housemate Laycon and her Deputy Head of House House, Prince on Saturday night. Dem re-play di video of how badly she behave and di strong language wey she use for Laycon before dem come hand over di strike plus disqualification. Biggie add say Erica ""deface im property, wen she pour water on top di head of house bed as she no want Prince to sleep beside her and dis kain behaviour dey unacceptable"". Big brother house get rules and regulations wey di lockdown housemates need to follow and Erica don break those rules two times before the last one wey lead to her eviction from di house. Mixed reactions na im come from fans of di popular reality TV show afta di disqualification of Erica. Some dey surprise, odas dey happy while some odas dey sad. Ngozi Nlewedim Alias Erica na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London. She say she dey passionate to be big time celebrity and like to get drunk and dance in front of di mirror alone." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54054244 +entertainment Wizkid fans dodge O2 Arena security to sneak enta im concert - See oda highlights of di show "Fans of Nigerian singer Wizkid dodge security for di O2 Arena on Sunday night, as dem sneak enta im gig on Sunday night. Videos full for inside social media show as pipo dey escape security barriers to see di Grammy nominated, Starboy. Di artist wey im real name na Ayodeji Balogun get three shows for di venue wey im dey do for London wey Sunday own na di first. Tok-tok pesin for di O2 Arena tok say dem quickly quench dat fire. She tok for statement say, ""Staff quickly calm di mata and fix di incident"". She advise fans say for di remaining shows for di rest of di week make dem try to dey show on time. Na dis particular show, Wizkid wey currently dey go by Big Wiz bin sell out in 12 minutes as part of im Made In Lagos tour." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59464165 +sports Iranian protesters jollificate over team elimination from World Cup "One man don reportedly dey killed by security forces for northern Iran, as anti-government protesters dey publicly celebrate say dia national football team comot from di World Cup. Tori be say Mehran Samak bin dey shot for head afta e honk im car horn for Bandar Anzali on Tuesday night. Videos from oda cities show crowds dey cheer and dance for di streets. Many Iranians no gree support dia football team for Qatar, sake of say dem see am as representation of di Islamic Republic. Anti-government protesters for Iran bin don dey celebrate for di national football team elimination from di World Cup, afta dia 1-0 loss to di USA. Videos bin show pipo dey dance for streets and honk car horns for Tehran and several oda cities for Tuesday night. Many Iranians no gree support dia football team for Qatar, dem see am as representation of di Islamic Republic. State-affiliated media blame hostile forces both inside and outside Iran say dem put unfair pressure on di players. Di players no sing di national anthem before dia first game, one 6-2 defeat by England, for one obvious expression of solidarity wit di protesters. But dem sing for di Wales game, wey dem win 2-0, and di politically-charged showdown against di USA. Some protesters  sedat one as betrayal of dia cause even though reports dey say di team bin come under serious pressure from Iranian authorities. Di unrest start 10 weeks ago following di death in custody of Mahsa Amini, one 22-year-old woman wey chop arrest from morality police for Tehran say e allegedly violate di strict rules wey say make women cover dia hair wit hijab. Authorities don respond to wetin dem see as foreign-backed ""riots"" wit violent crackdown wey human rights activists say at least 450 pipo don dey killed, including 60 children. More dan 18,000 odas dey reported to don chop arrest. One video wey dem post online on Tuesday night bin show plenti pipo dey celebrate di Iranian football team loss for one square for Mahsa Amini home city of Saqqez, for di kontri north-west. Video show as dem dey cheer and wave headscarves before fireworks dey set off. BBC Persian also gbab similar videos from plenti oda cities in the predominantly Kurdish region, where dozens of protesters have reportedly been killed by security forces in recent weeks. Video show Crowds dey dance to music for Sanandaj, one epicentre of di unrest, while for Kermanshah and Marivan hear dem dey chant ""Woman, life, freedom"" - one of di main slogans of di protests. For Tehran, students for Imam Sadiq University bin gather outside one hall of residence and dey sing ""Death to di dishonourable"" - one adjective protesters don use against security forces and wey fans dey shout inside di stadium during Iran match against England. Di opposition activist collective 1500tasvir bin post videos say e show security forces open fire for protesters wey dey celebrate for di south-western city of Behbahan and beating woman for Qazvin, near Tehran. E bin also get one confrontation between opponents and supporters of di goment outside di Al Thumama Stadium for Qatar afta Tuesday match. Danish journalist Rasmus Tantholdt film some men wey carry Iranian flags dey shove one man wey wear T-shirt dey say ""Woman, life, freedom"" for English. One woman wey dey wit am dey complain say she attack and ask for help to leave di stadium safely. Anoda video wey reach BBC Persian domot bin show male protester as dem violently chop arrest from security guards outside di stadium while dem dey shout ""Woman, life, freedom"". State-affiliated media for Iran meanwhile bin praise di national football team despite say dem no qualify for di World Cup knockout stages. Di conservative Farhikhtegan newspaper say ""we dey proud of Iran"", while di Revolutionary Guards-linked daily Javan say di team bin ""win di real game: di game of uniting pipo hearts"". Keyhan, wey dia editor dey appointed by di supreme leader, bin say di team bin go di tournament under ""di most unfair conditions"", witpressure from ""mercenaries home and abroad"". Before di match, di hard-line Tasnim tori pipo bin reject one report by CNN, wey cite one unnamed security source dey say di Revolutionary Guards bin threaten di families of di Iranian players wit ""imprisonment and torture"" if dem no ""behave""." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz401zw92vro +sports Meet Adijat Adenike Olarinoye, she win Nigeria first gold medal for 2022 Commonwealth games Weightlifter Adijat Adenike Olarinoye don win Nigeria first gold medal for di 2022 Commonwealth Games wey dey take place for Birmingham. Olarinoye lift a total of 203kg to win gold for di women 55kg weightlifting event. She bin lift 92kg for di snatch, 111kg for clean and jerk, and lift 203kg in total. India lifter, Bindyarani Devi Sorokhaniban settle for di silver, while England lifter, Fraer Morrow settle for di bronze. Olarinoye victory cause plenti jubilation for Team Nigeria camp afta di oda Nigerian lifters fail to make di podium. Nigerians still dey hope say dia athletes wey go represent di kontri for di Commonwealth Games go win more medals afta Olarinoye victory. Adijat Adenike Olarinoye na 22 years old according to her informate for di Birmingham 2022 website. Dem born Olarinoye on 14 July 1999. She come from Southwest region of Nigeria. Olarinoye don first help Nigeria win three medals for 2019 African Games wey dem bin do for Morocco. Dat time, She get di first gold medal of di day for di 55kg category. She den later add anoda gold for di 55kg Clean-jerk category before adding anoda silver medal. Olarinoye also win gold medal for di 2021 International Weightlifting Federation, World Championship wey take place for Tashkent, Uzbekistan. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c72qn9wjvg9o +sports Champions League group stage match results on Wednesday in fotos Liverpool lose dia opening group match for Uefa Champions League on Wednesday night. Napoli flog last season runner up Liverpool 4- 1 for Italy for dia group A match. Wednesday matches produce a total of 26 goals. Na Barcelona and Napoli games get high scores on Wednesday wit six and five goals respectively. Di group stage start on September 6 and e go end for November 2. Na February 14 di knockout stages go begin and end wit di final for Istanbul on June 10, 2023. Checkout eight ogbonge fotos dem from all di games on Wednesday. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd1nl5l3vd3o +sports Logan Paul vs Mayweather: Date, time and how to watch di fight Logan Paul and Floyd Mayweather dey fight each oda dis weekend. Di boxing match go happun on June 6 for di Hard Rock Stadium for inside Miami, for United states of America. Tori be say Mayweather fit make up to $100m, for dis im fight wit Paul. Dis na everything you need to know about di fight. Pay TV company DStv say dem go broadcast di exhibition bout between 12-time five-division champion Floyd Mayweather and social media sensation Logan Paul for Supersports on Monday by 1am. Logan Paul na 26-year-old man from Ohio him and im brother, Jake, first became famous for dia Vine and YouTube videos. Paul come move go L.A. and do different things for di entertainment industry, from acting to running a clothing line. Him YouTube channel get more than 22 million subscribers. As for sports, Paul be do sports for high-school, wia im participate for wrestling and football. But his boxing record no really set like dat. Floyd Mayweather Jr. senior Paul, at 44 him dey much more experienced for di ring. Him don 15 major world titles in five weight classes, im record for di sport dey spotless 50-0, him also get bronze medal for di 1996 Olympics. E also get three U.S. Golden Gloves championships, among oda titles. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57367964 +sports Ballon d’Or: David Beckham,Thierry Henry and oda great players wey no win best footballer of di world award Afta Lionel Messi win im 7th Ballon d’or player of di ear award, some arguments still dey go on ontop social media weda or not e deserve am. According to many, na Bayern Munich and Polish striker Robert Lewandowski deserve to collect di award while odas say for helping Argentina win dia first Copa America title in 28 years, Messi worth am. As fans dey drag each oda, we say make we chook eye check out great players from di past wey no win Ballon d’Or even though some feel say dem deserve to win am at some point. Thierry Henry For everything wey di great French striker achieve for football, Ballon d’Or na one thing wey dey miss from im collection. From becoming highest goal scorer in di history of Arsenal and di French national team to winning di FIFA World Cup and UEFA champions league, ‘Titi’ as im teammates bin dey call am get many achievements for football. But di closest Henry come to winning dis prestigious award na wen e come second to winner Zinedine Zidane for di 2004 edition. Samuel Eto’o Dis former Cameroonian striker take di world by storm afta e move from Real Mallorca to Barcelona for 2004 and dia e become one of di best strikers in history of football. Even though e win African player of di year 4 times, several la liga titles and two UEFA champions league with Barcelona, di closest di player come to di Ballon D’or na when e come third for 2005. Players wey stop am from winning di award dat year na im club teammate Ronaldinho and Frank Lampard of Chelsea wey come second. David Beckham Even though e get pipo wey feel say Beckham popularity pass wetin e achieve for football, e still be one of di best players wey don play football. Apart from say di former England winger dey inside di list of ‘Pele 100 greatest players in history’ e still achieve many tins for di game wey include league titles and Champions league with Manchester United and Real Madrid. For all e achieve, Beckham no eva enter di top 3 best players for di world talk less of winning di Ballon D’or. Didier Drogba Dis Ivorian na di number one as far as Chelsea dey concern. Na player wey leave plenty legacy for di blues and dey highly regarded for world football. E helep Chelsea win dia famous first UEFA champions league title for 2012 not forgetting premier league titles and Cups. Despite all dat, im hand only touch di Ballon D’or award wen e present di 2021 winner Lionel Messi for di ceremony on Monday, as for imself di closest e come na wen e come 4th for 2012. E win two African player of di year awards though. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59474869 +politics Maurice Kamto: Cameroon opposition leader free from house arrest afta 78 days Life don turn to normal around opposition leader Maurice Kamto e house as de last police komot for night. One of Kamto lawyers write for night say de last policeman don komot for de house. Release from Cameroon tok-tok pesin Rene Sadi say, goment decide for relax measures weh deh take for counter Kamto e plans afta regional elections pass fain. For 78 days, Maurice Kamto no komot for e house since e bi organise march for chase President Biya for pawa. Also, Kamto bi say regional elections no go hold, if goment no solve Anglophone crisis. But territorial admin minister Paul Atanga Nji bin warn say deh go fit put Kamto for prison again. Authorities bin put police around Kamto e house for September 20, days before de march. Also deh arrest Cameroon Renaissance Movement, CRM party members. Goment say deh don free all of CRM members. As regional elections hold for December 6, police leave Kamto e house. For now, Kamto bi free as police no dey for stop e, but e nova make any statement. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55242174 +entertainment Femi Otedola: DJ Cuppy father gift Ferrari Portofino to Tolani Otedola and Temi Otedola in one day inside dis 2020 "Florence Ifeoluwa Otedola AKA DJ Cuppy daughter of Nigerian billionaire Femi Otedola take to her Twitter, Instagram and Facebook on Wednesday to rock di new Ferrari Portofino motor wey dia papa gift dem. Tori be say DJ Cuppy father Femi Otedola gift Ferrari Portofino to Tolani, Temi and Ifeoluwa Otedola (all im three daughters, including Cuppy) in one day for dis 2020. Di cost of one Ferrari Portofino fit reach at least $218,750 (84,323,750.00 Nigerian Naira) starting price, according to Car and Driver price review for 2020. Femi Otedola na Nigerian businessman and according to list of Nigerian billionaires by net worth wey Wikipedia publish for 2016, di man pocket get reach USD 1.85 Billion. ""Papa take us shopping and buy one for each of us!"" Na di words Temi Otedola tweet. Meanwhile Ikorodu Bois enta social media begin copy copy wetin di Otedola daughters do." https://www.bbc.com/pidgin/world-54175987 +business Cryptocurrency CBN ban in Nigeria: Which African countries dey show support for Bitcoin, Dogecoin, Ethereum for di continent? Even though many of im pipo dey trade in Cryptocurrency, African kontries never show di kain support wey many expect, although some don dey take small-small step to accept am. Bitcoin, Dogecoin, Ethereum - dis na some of di popular cryptocurrency wey Africans don dey trade in and di fact say many kontries never recognize am as legal money no stop di growth. One report by sabi company Baker Mckenzie say Nigeria na number three in di world for countries wey dey trade in Bitcoins (wey be di most popular type of cryptocurrency). And Paxful, wey be crypto exchange platform say for 2020, Nigeria na im do crypto trading pass for Africa wit volume of 60,215 Bitcoins wey worth $566,668,692. Some don argue say if African kontries regulate crypto, e go make am dey even more popular, and make di economy ginger. But odas reason am to be like gambling. Make we torchlight wetin some African kontris don tok (or no tok) about di use of cryptocurrency. Di Bank of Ghana no recognize cryptocurrency as legal form of currency, although dem don arrange Bill to regulate cryptocurrency. Nigeria Security and Exchange Commission (SEC) for statement wey dem release for dia official website in 2018 say dem go regulate digital assets like cryptocurrency because 'digital asset offerings' like crypto-token or crypto-coin dey provide anoda wey wey pipo go fit invest or keep dia money as asset. Dis ground breaking statement surprise many as e be say di Central Bank of Nigeria don draw ear before give kontri pipo say dealers and investors in any kind of crypto currency in Nigeria no dey protected by law, according to one CBN circular on 28 February, 2018. For February 2021, di CBN give order say make financial instructions close down accounts of any customer wey dey involved wit cryptocurrency. Kenya goment no recognise cryptocurrency because of di way e dey difficult to regulate am although dem don form task force wey go torchlight whether dem fit adopt am. As one of di most advanced economies for Africa, dem don dey look into how dem fit allow cryptocurrency. In fact, di national treasury don propose say make dem change di law to recognise am. And di Crypto Assets Regulatory Working Group na im dey responsible to torchlight any law wey fit epp dem legalise crypto. But di South Africa Reserve Bank never comot any law to give am legal backing. Di kontri no be stranger to di different financial trading service wey di world dey move to. Di island country get many forex trading companies wey dey registered dia and for crypto dem don arrange one framework to allow am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55952803 +sports England vs Denmark: Harry Kane goal knock out Christian Eriksen side to take di Three Lions to Euro 2020 finals England beat Denmark 2-1 for Wembley stadium for London to set up a final with Italy on Sunday. Harry Kane goal through penalty for extra time for di 103rd minute put England for di lead and see dem win di game. Dis na afta Joakim Maehle trip Raheem Sterling inside di box and give England di penalty. Although Kasper Schmeichel bin save Harry Kane penalty, di ball drop straight into the path of Kane path again for am to slot am into di net. Before den, Mikkel Damsgaard goal for di 29th minute with free kick afta Luke Shaw grab Andreas Christensen for 25 yards out. Na di first free kick goal for di tournament. Denmark goal na di first score against England since March, ending a run of 691 minutes without conceding for di Three Lions. Na for di 39th minute England restore parity through own goal by Simon Kjaer Di 11th own goal of di tournament. England bin dey look to reach dia first ever men Euros final & first major tournament final since 1966 and dem do am. Dis na di second semi-final match of Euro 2020, England go play Italy for di Sunday final. Na just one change England bin make as dem bin hope to make history and reach di European Championship final for di first time. Arsenal exciting 19-year-old winger Bukayo Saka start ahead of Jadon Sancho, wey dey bench. Ben White, Ben Chilwell or Dominic Calvert-Lewin no dey stating line-up and dem no dey bench too. Meanwhile Denmark maintain di same team wey win di quarter-final match against Czech Republic last Saturday. Dia coach Kasper Hjulmand bin tok afta di match say tiredness na major concern but im go with the same XI again. Na Simon Kjaer captain di Danes. England XI: Pickford, Walker, Stones, Maguire, Shaw, Rice, Phillips, Mount, Saka, Sterling, Kane. Denmark XI: Schmeichel, Christensen, Kjaer, Vestergaard, Stryger Larsen, Hojbjerg, Delaney, Maehle, Braithwaite, Dolberg, Damsgaard. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57753501 +entertainment What is Charlie Charlie?: All you need sabi about di trending Charlie Charlie challenge """Charlie, Charlie, are you there? na di new trend wey dey burst social media. Close to 200,000 pipo for Nigeria don use di hashtag #CharlieCharlie in di last four hours and several millions of pipo for di world don join di Charlie Charlie challenge. How di trend take enta Nigeria? we no know but we understand say Charlie Charlie na one game wey don dey tey-tey. Di game involve to balance two pencils on top each oda, come put for paper, wey dem write Yes or No. Players go come ask question wey Charlie go respond by moving di pencil to di direction of di Yes or No answer. Plenty Nigerians don follow join di game wey some pipo claim say dey demonic. Charlie Charlie na Ouija board-like game wey players go write ""Yes and No"" on top paper, come balance two pencils for di paper. Di players go divide one piece of paper into four quadrants, label each side wit either ""Yes"" or ""No"". Then put one pencil on one line, balance anoda one on top, come say ""Charlie, Charlie, are you there?"" If Charlie ""answer"" di pencil wey dey on top go move to one of di answers, e be like compass. You fit come begin ask Charlie any oda questions. Examples na ""Charlie, I go pass my exam?"" or ""Charlie, I go get money?"" etc. Several reports and tweets claim say di game na from Mexico. For example, one of di most retweeted videos about Charlie Charlie Challenge, shows one popular Mexican beer brand for Spanish write""yes"" and ""no"" for di body. Di tori wey bin go round na say Charlie na Mexican child wey die. Some tori say na Mexican demon or pagan god or di victim of some kind of violent crime. But none of dis tori dey confirmed. Even at dat, many pipo believe say Charlie na ghost or spirit from hell wey fit answer questions about whether your crush like you. However, BBC Mundo correspondent Maria Elena Navez say no demon dey wey dem dey call ""Charlie"" for Mexico. She say to describe di game as traditional Mexican way to call dead pipo na just way to hype am and make am sound mysterious. One sabi pesin for Live Science Elizabeth Palermo explain say di pencils no balance well on top each oda, so, if small wind blow am, e go move. She say na unstable structure wey dey bound to move." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55562622 +sports Pogba agree four year deal with Juve, Chelsea wan wrap up two deals dis week Former Tottenham manager Mauricio Pochettino, 50, dey eye return to di Premier League after Paris St-Germain announce im sacking on Tuesday (Sun) Juventus don reach agreement to re-sign midfielder Paul Pogba, 29, on four-years deal after di France World Cup winner contract expire for Manchester United. (Sky Sports) Leicester don open discussions with Feyenoordfor 21-year-old Turkey international midfielder Orkun Kokcu. (Mail) Southampton dey in talks to sign Nigeria international midfielder Joe Aribo, 25, from Rangers for £10m. (Athletic - subscription required) Chelsea dey hope to complete di signing of one of dia two defensive targets dis week, negotiations dey go on for Netherlands internationals, Juventus' Matthijs de Ligt, 22, andManchester City's Nathan Ake, 27. (Standard) Tottenham dey keen on signing Villarreal'sSpain international defender Pau Torres, 25, despite say arrival of France centre-back Clement Lenglet, 27, from Barcelona dey close. (Mirror) Everton don enquire about di availability of Chelsea Albania international striker Armando Broja, 20, as replacement for Richarlison, who don join Tottenham. (Telegraph) Arsenal don collect notice say dem need to pay £55m for Lazio midfielder Sergej Milinkovic-Savic or else make dem forget any deal. (sky) Fulham don get dia bid worth up to £10m accepted by Manchester United for attacking midfielder Andreas Pereira. (Sky) Barcelona don reignite dia interest for Ajax left-back Nicholas Tagliafico, Di 29-year-old Argentina international dey available for £4.3m. (Sky) https://www.bbc.com/pidgin/articles/cnexvn8w7yeo +entertainment AMVCA: 2022 Africa Magic Awards Nominees don land- See who dey list "Africa Magic Viewers' Choice Awards (AMVCA) wey be like Africa version of Oscar don release full list of nominees for di 2022 edition. Africa Magic Viewers' Choice Awards, dey celebrate di work and talent of actors, producers, directors, and oda film professionals. Di Award organisers, South Africa TV cable company Multi Choice announce say di award gala go hold on May 14. Here na di list of Nominees; Best Actor in a Comedy (Movie/TV Series) Best Actor in a Drama (Movie/TV Series) Best Actress in a Comedy (Movie/TV Series) Best Actress in a Drama (Movie/TV Series) Best Supporting Actor (Movie/TV Series) Best Supporting Actress (Movie/TV Series) Best Short Film Or Online Video Best Director (Movie) Best Soundtrack (Movie/TV Series) Best Online Social Content Creator Best Indigenous Language Movie or TV Series (Igbo) Best Indigenous Language Movie or TV Series (Hausa) Best Indigenous Language Movie or TV Series (Yoruba) Best Indigenous Language Movie or TV Series (Swahili) Best Television Series (Drama/ Comedy) Best Africa Magic Original Drama Series Best Africa Magic Original Comedy Series Best Makeup Best Sound Editor (Movie/TV Series) Best Documentary Best Lighting Designer (Movie/TV Series) Best Art Director (Movie/TV Series) Best Costume Designer (Movie/TV Series) Best Cinematographer Best Picture Editor Best Writer (Movie/TV Series) Best Movie (Southern Africa) Best Movie (East Africa) Best Movie (West Africa) Best Overall Movie Multichoice Talent Factory Oda awards wey dey go give during di awards night Di 2022 Africa Magic Viewers' Choice Awards na di eighth edition and many Nigerians including nominees don begin react. Nigerian film actress and producer, Funke Akindele Bello don react for her Instagram page afta her name come out as part of di nominees. She post one video of hersef and caption am; ""Di Ghetto in me no dey go any where. Dis nominations loud o!! All glory to God!!"" For her Instagram post, Funke Akindele come continue to list all di categories wey her name come out; Nigerian actress, model and media personality, Nancy Isime react say she dey 'speechless but deeply thankful' for di nomination. Nancy Isime post for her official Instagram handle say dis nomination na very big deal to am as e be say di AMVCA dey considered as Africa version of 'Oscars'. Also, Nigeria actor Timini Egbuson enta twitter to express im joy about di nominations. ""Feels so good to get all di hard work constantly recognized"", Timini tok. Di actor also go further to list all di categories dem nominate am for, then thanks pipo for dia 'constant love and support.' Former Big Brother Naija housemate, Diane Russet wey dey among di nominees for Best Indigenous Language Movie or TV Series (Hausa) also don react with happiness. Here na reactions from oda actors and Nigerians;" https://www.bbc.com/pidgin/tori-60818021 +business Coronavirus: ‘Free market dey allow make traders overprice hand sanitizers, despite over 300% increase – Consumer Protection Agency "Ghanaians dey complain about de sudden increase in cost of hand sanitisers after de country record six cases of coronavirus. Ghana goment impose ban on all public gatherings like conferences, funerals, festivals, political rallies, Church services, Islamic worship for 4 weeks starting Monday, March 16 sake of de outbreak. President Nana Akufo-Addo plus health officials for de country direct citizens, supermarkets, shopping malls, restaurants den stuff say dem for observe enhanced hygiene, ensure regular use of hand sanitizers and running water plus soap for washing of hands. Coronavirus: See how to make your own hand sanitizer After dis announcement, price of sanitisers shoot up across de country. One consumer, Abigail Lamptey talk BBC Pidgin say ""I go ask for small hand sanitiser wey dem dey sell at Ghc3, but now dem dey sell am Ghc15. I ask dem say why, dem say sake of coronavirus"" Another consumer, Sarah talk reveal say ""if you go Kaneshie and Makola markets de Ghc2 sanitisers dey cost Ghc10 now."" Per calculations wey BBC Pidgin make de prices wey retailers charge de two consumers increase by over 300 percent. Dis reality be the same for most parts of de country. Chief Executive of Consumer Protection Agency, Kofi Kapito explain give BBC Pidgin say despite say de price increase no sheda fair, free market dey allow make traders sell like that. ""We dey inside free market, de markets no be regulated by goment. People for use fair judgement but sake of free market e go be very difficult to regulate prices"" ""I be consumer, I no go like many anybody take advantage of me but that be de reality of wanna market"" he add. Ghana record six cases of coronavirus but officials say dem dey work hard to prevent community outbreaks which go be hard to deal with. De country ban all travellers wey visit any country wey kontri wey record at least 200 cases of COVID-19 from entering Ghana unless dem be Ghanaian citizens no go." https://www.bbc.com/pidgin/51930736 +politics Osun state election result 2022: PDP Ademola Adeleke win governorship poll - Results from di 30 LGAs PDP candidate, Senator Ademola Adeleke don win di Osun state govnorship election wey happun on Saturday,16, July, 2022. E win 17 out of di 30 local goment results wey di Independent national electoral commission announce to win. Di election see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991. Na fifteen candidates bin dey di race to become di next govnor of di South Western state. Ademola Adeleke wey be di candidate of di main opposition party for di state emerge winner afta e poll 403,371 to beat im closest rival Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress wey polled 375,027. Na Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC announce di winner of di election. According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast. Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election). Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions. https://www.bbc.com/pidgin/tori-62189734 +business Ngozi Okonjo-Iweala WTO: Biden end Trump dust for Okonjo-Iweala World Trade Organization race to be Director General "Ngozi Okonjo-Iweala WTO race to be Director General of Word Trade Organization receive correct boost from Donald Trump successor, President Joe Biden goment of United States. Tori be say America don finally support Nigeria former Finance Minister, Ngozi Okonjo-Iweala for di race to lead World Trade Organisation. Ngozi Okonjo Iweala on Saturday morning post for her official social media handle say: ""Grateful for di expression of support from di US today for DG WTO. Congratulations to Madam Yoo of Rep. Korea for hard-fought campaign. Thank You, President Muhammadu Buhari and all Nigerians for your unflinching support. Thank you, friends. Love to my family."" Di US under di goment of Donald Trump, bin favour South Korea Trade Minister Yoo Myung-hee wey later come withdraw from di race yesterday. President Biden goment on Friday express ""strong support"" for Nigeria ex-finance minister race to be Director General of Word Trade Organization. Ngozi Okonjo-Iweala don be frontrunner for di role DG of WTO but Trump goment bin oppose last October say e want another woman, South Koreas Yoo Myung-hee. Ms Yoo done now withdraw her candidacy. If Dr Okonjo-Iweala chop confirmation for di role, e go be di first woman and first African to lead WTO. Dr Okonjo-Iweala on Friday praise her rival for di post and say: ""E get importal alias vital work ahead to do together."" For October, one WTO nominations committee recommend say make dia 164 members appoint Dr Okonjo-Iweala as replacement to di outgoing chief Roberto Azevedo. Even one tok-tok pesin during dat time tok say all of dem don approve di appointment ""except for one"". President Donald Trump wey bin describe di WTO say dem dey ""horrible"" and biased toward China - bin want Madam Yoo, South Korea trade minister to lead di organization. Madam Yoo on Friday tok say she make her decision to withdraw her candidacy afta ""close consultation"" with di US. ""South Korea go actively contribute to reaching agreements for di next WTO chief and co-operate with her and participate for di WTO reform process."" Di White House congratulate madam Yoo for her ""strong campaign"" for the di position and for her to be ""traiblazer"" as South Korea first female trade minister. For one statement, di White House tok say; ""US dey ready to engage for di next phase of di WTO process to agree with everybody concerning di decision on di WTO Director General"". Na President Mohammadu Buhari nominate Ngozi Okonjo-Iweala as candidate for director-general of di World Trade Organization in June 2020" https://www.bbc.com/pidgin/world-55961098 +entertainment Eedris Abdulkareem: Interesting facts about di Nigerian singer wey sing Jagajaga reloaded "Eedris Abdukareem dey trend for social media space after Nigerian Minister, Festus Keyamo call am out for alleged blackmail. Dis dey follow di release of im new song ‘Jajajaga reloaded’ wey di Minister alleged say di Nigerian artiste bin try blackmail am wit di song. Di veteran artiste bin first release di first version of di ‘Jaga Jaga’ song for 2004 wey make am chop ban from playing on radio and also from performing for live concerts and events. Abdulkareem third album ""Jaga Jaga"", (Yoruba word for shambles) , wey im use address corruption and suffering for Nigeria no too go down well with former president Olusegun Obasanjo led administration sake of say dem believe di song dey paint di kontri in a bad light. Eedris Abdukareem dey popular for songs wey dey address political, societal and cultural issues for Nigeria. Dis na wetin pipo fit no sabi about di veteran hip hop artist. Im full name na Eedris Turayo Abdulkareem Ajenifuja. Dem born Eedris for 1974. He perform wit hip-hop and The Remedies from 1997 until dem split in 2002. He continued as a solo artist and release di album P.A.S.S. (Pains And Stress = Success) for 2002. Later di same year, he release one album wey dem title Mr. Lecturer. Di title track of dat album address sex for grades matter for Nigerian colleges and universities. In response to in temporary ban from di music scene, for 2005, di ‘Jaga Jaga’ crooner release anoda album, ‘Letter to Mr President’ wia im address President Obasanjo on corruption mata for di kontri. “Stand up make we fight dis corruption. Jaga Jaga no be insult, e mean say things don spoil. Wen I say Jaga Jaga, dem say I no get sense but now I don become prophet” part of di lyrics of di title track tok. Di Minister of state for labour, accuse di rapper say e wan wan blackmail am afta im no gree give am money to support President Muhammad Buhari administration. Di minister share screens hot of im claims on im Twitter page to show evidence say di rapper bin beg am for money. Eedris later enta Instagram to respond to di Minister accuse say ‘Keyamo dey in pains because of im next ambition to become govnor”. Di rapper also say e no dey true say im bin dey ask money to support Buhari administration, he say im only reach out to ‘a brother’ for support wen im mama dey sick. Explaining why im drop a remix of im classic ‘Jaga Jaga’, He say, Jaga Jaga reloaded na “na facts. Nigeria never had it so bad. Di Jagajaga don take big dimension. We must keep dey ask questions. We must ask di cabal questions."" Dis no be di first time Eedris Abdukareem don dey limelight sake of gbas-gbos. E get one popular gbege wey happun between him and popular American rapper and singer, 50cents. According to wetin tori pipo for Pulse report in 2016, dem tok say during one Sean Paul show for 2004, di Nigerian artist wey dey on di supporting bill no get better treatment from di organisers. Security men bin flog dem for backstage sake of say dem wan clear road for Sean Paul to pass. Dem also tok say dem no pay di Nigerian acts well. Afta im perform for 2 out of 4 shows, 50 Cent and im crew bin dey board plane dey go Port Harcourt wit one ADC flight. On di flight Eedris Abdulkareem try to sit on one seat dem reserve for 50 Cent. 50 cents bodyguard stop di Nigerian rapper but . Eedris no gree for di mata as e cause back and forth for inside di plane. Sake of dis, 50 Cent no later perform for di remaining two shows and im comot Nigeria. For 2007, Eedris Abdulkareem later tok sorry to 50 Cent on stage for di KORA Awards in Abuja. As pipo dey continue to tok about Eedris Abdulkareem's Jaga Jaga Reloaded protest song, here are some oda protest songs wey make waves for Nigeria during dia time.Lead us well- Dis 2003 song by singerAfrican china almost become national anthem at di time because of how well e reign. Di song bin dey specifically tok to Nigerian leaders telling dem to lead well and save di kontri from collapsing. E dey pain me- Dis na anoda popular protest song and na former Plantashun Boyz star Black face sing am when e begin im solo career for 2005. Di song tok about problems like corruption, lack of salary payment and oda issues disturbing Nigeria during dat time. Under pressure- dis song wey di late Nigerian reggae artist Ras Kimono release for 1988 na anoda protest song wey really make waves dat time. Di popular singer wey die for 2018 do di song to tok about all di problems wey Nigeria dey face at di time and how leaders no dey try help solve dem." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56885637 +sports Nigeria serve Sao Tome & Principe wotowoto promax wit 10 goals to nil Nigeria Super Eagles beat Sao Tome & Principe 10 to nil today for di Group A of di Africa Cup of Nations qualifiers at di Adrar Stadium for Agadir, Morocco. Victor Osimhen wey be di star of di match score four goals for Nigeria during di match. Super Eagles winning dey come afta dem beat Sierra Leone 2:1 for di Moshood Abiola Stadium in Abuja on Thursday 9 June. Na three goals Nigeria score for first half and na Osimhen score di first goal while Simon Moses score di second goal. Terem Moffi score di third goal. Oda players wey score for di match na Etebo, Lookman and Dennis Emmanuel wey score wit penalty. Na di second time Jose Peserio go win match for Nigeria since im take over from Augustine Eguavoen. Na only two of di four teams wey dey for Group A go qualify for Afcon 2023 wey go shele for Ivory Coast. 45 mins: Sao Tome & Principe 0 - 3 Nigeria Di ball possession for Nigeria na 71% while Sao Tome & Principe get 29%. Nigeria hold di ball till referee blow whistle for end of second half. Referee Koto O don add two minutes. 44 mins: Di Super Eagles still dey lead and dem apply pressure to score di fourth goal as dia opponents no gree dem. 43 mins: Terem Moffi score third goals for Nigeria. 41: Di Falcons dey find dia first goal as dem hold di ball but Super Eagles collect am back. 39 mins: Free kick for di Falcons. Moffi shot enta di Falcons keeper hand. 34 mins: Di Super Eagles dey control di match and dia opponents neva proof too difficult for dem. 33: Osimhen enter offside as e want score di third goal. 31 mins: Free kick for Sao Tome & Principe. 28 mins: Moses Simon score di second goal for Nigeria afta assist by Osimhen. Nigeria dey press for di second goal. First corner kick for di Super Eagles. Victor Osimhen score second goal for Nigeria but na offside. 9 mins: Victor Osimhen score first goal for Nigeria. Referee blow di final whistle Nigeria ball possession na 66% while Sao Tome & Principe get 34%. 90+2 mins: Emmanuel Dennis score tenth goal for Super Eagles wit penalty. Referee blow penalty whistle for Nigeria afta dem fall Emmanuel Dennis. Referee add two minutes more for di game. 89 mins: Sao Tome & Principe attempt for dia first goal but e no enta. 84: Victor Osimhen score di ninth goal for Super Eagles. Na im fourth goal for di game be dat. 81 mins: Umar shoot but di goalkeeper catch am. Dem deny Nigeria anoda goal for offside. 74 mins: Cooling break. Leon Balogun enta for Calvin Bassey, Emmanuel Dennis enta for Ademola Lookman, Sadiq Umar enta Terem Moffi. Some substitutions for di Super Eagles. Sao Tome & Principe dey find penalty as dia player fall for 18-yeard box but referee say no. 66 mins: Sao Tome & Principe still dey find dia first goal but Nigeria no allow dem hold ball for long. 65 mins: Victor Osimhen score hattrick as e score Nigeria 8th goal. 64 mins: Lookman score di seventh goal for Super Eagles. 60 mins: Terem Moffi score di sixth goal for Super Eagles. 58 mins: Ahmed Musa substitute for Moses Simon. 58: Nigerian defender Aina chop yellow card. 56 mins: Osimhen score wetin suppose be hattrick but offside. 55 mins: Etebo use free kick score Nigeria fifth goal. 52: Across from Di Falcons as dem still dey find dia first goal. 51 mins: Nigeria still dey in charge of di ball possession as dem dey press dia opponent. 48 mins: Victor Osimhen score fourth goals for Nigeria. Sao Tome & Principe and Nigeria battle each oda today in di Group A of di Africa Cup of Nations qualifiers at di Adrar Stadium for Agadir, Morocco. Dis dey come afta di Super Eagles sama Sierra Leone 2:1 for di Moshood Abiola Stadium in Abuja on Thursday 9 June. Na di same day wey Super Eagles defeat Sierra Leone Sao Tome & Principe chop 5:1 from Guinea-Bissau. But defeat of Guinea-Bissau na Nigeria first win in five matches since dia embarrassing loss for Afcon 2021 for Cameroon and dia failure to beat Ghana to qualify for di Qatar 2021 Di Falcons wey never meet wit di Super Eagles before dey face di three-time African champions for di first time. Tori be say Sao Tome & Principe neva qualify for di Africa Cup of Nations before and Nigeria don collect am three times. Di match dey shele today at 14:00 (2pm Nigerian time). Di 2023 Africa Cup of Nations go shele for Ivory Coast. Uzoho (GK), Aina, Zaidu, Ajayi, Bassey, Etebo, Simon (C), Iwobi, Moffi, Lookman, Osimhen. Nigeria team substitutes Adewale, Onyeka, Balogun, Musa, Aribo, Cukwueze, Shehu, Adeyinka, Dennis, Umar, Dessers, Omeruo. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjk0m8znd07o +politics PDP presidential primary 2022 winner results: Atiku win "Atiku Abubakar don emerge presidential candidate of Peoples Democratic Party [PDP] for 2023 general election. PDP wey be Nigeria main opposition party vote on Saturday May 28 to choose di best candidate wey go be di presidential flag bearer of di party. Di Presidential Primary 2022 na part of preparation for di next year election. Na 13 aspirants, as at Saturday morning, dey contest to be di presidential candidate of di party. Former Vice President of Nigeria, Atiku Abubakar get 371 votes. Govnor of Rivers state Nyesom Wike record 237 votes Former Senate President, Bukola Saraki pull 70 votes Akwa Ibom State Governor, Emmanuel Udom score 38 votes Bauchi State Govnor, Bala Mohammed get 20 votes Former Senate President/SSG, Pius Anyim collect 14 votes Tambuwal step down from PDP presidential race for Atiku Pharmacist, Sam Ohabunwa take 1 vote Female aspirant, Olivia Tariela take 1 vote Publisher, Dele Momodu score 0 Former governor of Ekiti State, Ayo Fayose score 0 Lawyer, Charles Okwudili get 0 Few days earlier, a strong aspirant and former governor of Anambra state, Peter Obi resign from di party on Wednesday. Then on di morning of di presidential primaries, anoda aspirant Mohammad Hayat-Deen withdraw from di race. Hayat-Deen drop dis one for letter wey im address to di PDP chairman, Iyiochia Ayu on May 27, 2022. Oga Hayat-deen tok say di exercise dey obscenely monetized"", and e go against im personal principles, among oda reasons. Di party say dem don ready kampe to successfully do dia special convention and elect a presidential candidate. Di move meet di June 3 deadline wey INEC first give for all parties in di kontri to submit di names of dia candidates. I7 aspirants bin start di journey to run for di highest office for Nigeria but a few of dem no make am pass di screening stage. Na only 15 aspirants qualify to run for di platform of di party, but Peter Obi resign im PDP membership, leaving just 14. According to di PDP tok-tok pesin, Debo Olugunagba say di party dey use indirect primaries to pick di party presidential flag bearer. And dat na only elected delegates wey be one pesin per local goment plus di three ad hoc delegates from di ward congresses go vote. PDP Presidential Primary 2022 go hold for di Abuja National Stadium. For di last few months, Nigeria political space dey coloured wit plenti political activities. Different aspirants on di platform of di opposition party dey criss-cross di kontri to woo delegates to vote for dem. Dia campaign promises dey loud as dem visit di delegates dem. And some promise dem say dem go tackle di issue of security, economy, and education and oda sector of di economy. Di mix of di aspirants cut across di different geo-political zones of di kontri and thanks to di party throway di zoning arrangement. Di party publicity director, Chinwe Nnorom say di party decide not zone in order to democraticise di process to reflect popular demand. Sake of dis, some of di aspirants don form coalition to out do demselves as dem use last minute to lobby di delegates. Last minute horse trading and politicking dey also go on for different quarters for di kapital. Dis year national convention to elect dia presidential candidate But dis year, dem go doa am for Velodrome for di national stadium. According to one PDP tofficial, e say e no be di plan of di party to choose di stadium. But dat wen dem apply to FCT to use di Eagle Square, di authority turn dem down. Na sake of say dem gatz secure di place for 24 hours since di president go attend di ruling APC presidential primaries on 29 May. Na about 810 delegates go vote during dis special national convention to elect a presidential candidate. Dis delegate go cast dia vote for dia preferred appriants. Dem go issue di delegates ballot paper wit di names of di aspirants and den, dem go tick di one dem like Di candidate wit di highest vote go win di primary and dem go declare am as di party presidential flag bearer. Delegate election dey very unpredictable sake of say dis delegates fit change dia mind anytime and e no dey clear who dem go vote. According to PDP tok tok pesin, statutory delegates like govnors dem and oda principal officers no go vote. Even say National Assembly don okay make dis statutory delegates vote but di Nigerian president neva sign am to law. And so di PDP no go use statutory delegates to elect dia presidential candidates. Di FCT Police Command don deploy large number of police officers for di venue of di PDP convention. Di command for statement say sake of di convention, dem go deploy security also across di capital to ensure di protection of lives and property Di police took tok pesin, Josephine Adeh for statement say dem go put counter insurgency measure, dem go do robust stop and search for strategic point around di suburbs and those on di ground, go control di crowd dem. According to political sabi pipo wey yarn wit BBC Pidgin, di first task for any pesin wey emerge as di party candidate na to unify di party. Through di electioneering process, di party structure dey divided along several lines wey fit affect dia success ahead of di election. Political analysts claim say if di candidate no pull everibodi togeda, di party no go go far. Anoda issue wey fit affect di candidate na finance, since di PDP leave power, moni to run di party and drive campaign na big case. Di candidate gatz get moni and unite party pipo togeda to fund dia campaign if not, moni fit serve as barrier to di candidate. also di larger scene, Nigeria for years now don dey face plenti security and economic wahala, di candate also gatz try fix those wahala if di person want nigerians to support am. Di need to also fix di power sector go be anoda major area to focus on if di candidate wan make di kontri beta." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61598228 +sports Man City Uefa ban: Manchester City don overturn dia two-year sanction from European competition on appeal to CAS "Manchester City don win dia case to comot dia two-year ban from European club competitions. Di Court of Arbitration for Sport (Cas) announce say di club no dey guilty of ""cuni cuni way wit money"" on Monday. Uefa Club Financial Control Body (CFCB) bin nack City di ban for February afta dem rule say di club don ""seriously break laws"" of Financial Fair Play (FFP) regulations between 2012 and 2016. City original fine of 30m euros (£26.9m) now don reduce to 10m euros. Cas ruling means City, wey e sure for say dem go finish second for Premier League dis season, go now play for di 2020-21 Champions League. Although Cas say City ""no follow cooperate with Uefa authorities"". Official response from di club say: di decision na ""proof of wetin di club don always claim and of di kain evidence wey we bring comot""." https://www.bbc.com/pidgin/sport-53366701 +sports Uefa apologise to Liverpool and Real Madrid fans "Uefa don apologise to Liverpool and Real Madrid fans wey di katata during di Champions League final affaect. Dem say e must not happun again. Liverpool fans describe di rough policing, poor planning and overcrowding during last Saturday showpiece game as sometin wey no make sense. Real Madrid don ask for answers on di ""series of unfortunate events"". ""No football fan suppose dey in dat situation, and it must not happen again,"" Uefa tok for statement. ""Uefa wish to sincerely apologise to all spectators wey experience or witness scary and distressing events for di build-up to di Uefa Champions League final for Stade de France on 28 May 2022 for Paris, on night wey suppose to be celebration of European club football."" European football governing body bin don announce independent review of wetin happun in di build-up to di final, and lessons to  learn, go dey led by Dr Tiago Brandao Rodrigues from Portugal. French authorities and Uefa bin blame late arrivals and fake tickets for di confusion outside di Stade de France, wey make dem delay di match for more dan 30 minutes. Police use tear gas and pepper spray on some fans. Dem also find out say some of di supporters become target of local gangs. France interior minister, Gerald Darmanin, say only English fans caused problem for di final. ""Di review na to establish full report and timeline of wetin happun during di day, both within di stadium and di surrounding areas, including investigating how fans take enta di stadium through different points,"" Uefa add for di statement." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cldv4405vy7o +health Coronavirus: Ghana hospital workers wey dey sell PPE for dia personal gain unmasked One Africa Eye undercover investigation don show say some staff for Ghana hospitals dey sell Personal Protective Equipment (PPE) for dia personal profit. More dan 2,000 medical workers for Ghana don catch coronavirus since di outbreak begin. Di kontri don see serious scarcity of essential protective equipment like face shields, masks and suits. Di investigation show how some medical workers dey make profit at di expense of dia colleagues. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53719592 +entertainment DJ Cuppy and Zlatan: Musician Zlatan on DJ Cuppy relationship, London concert surprise "Zlatan don speak to BBC Pidgin on DJ Cuppy appearance for im London concert. Di London-based Nigerian Disk Jockey, Florence Otedola, popularly known as DJ Cuppy, surprised Nigerian singer, Omoniyi 'Zlatan' Raphael during im Sunday night London concert. Tori be say di two successfully reunited and performed dia hit single ""Gelato"", afta months of gbasgbos. DJ Cuppy share a video wia she show up at di O2 Arena and surprised Zlatan by joining him on stage. Before going on di stage, DJ Cuppy say, ""I'm about to go on stage and surprise Zlatan. He no know."" On Monday morning Zlatan tell BBC Pidgin say; ""From Manchester to Birmiham and London, I see lot pipo dey sing my song, word for words. ""I see a lot of pipo dey smile, and then di gestures"" On Zlatan and DJ Cuppy relationship - di singer say: ""E dey calm, no bad blood, evri one dey cool now. E just dey right to let peace reign. ""And then no promote any kind of bad blood. So we dey cool and calm."" On any future plan to collabo wit DJ Cuppy, Zlatan say yes! ""We dey cool and calm and so definitely ..."" DJ Cuppy take to Twitter on Monday after di concernt to tell her fans say: ""Cupcakes, I hope I inspire una to squash any beef una get… LIFE DEY TOO SHORT! 💞 Here be my advice: "" Always forgive but never forget. Learn from your mistakes but never regret. Pipo change and things go wrong… But always remember life goes on.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-59127466 +sports Belgium vs Italy: Prediction for Belgium vs Italy & match facts Belgium go jam Italy for Football Arena for Munich, Germany as di quarterfinal round of Euro 2020 begin today. Kick off for di ogbonge match na 8pm West African Time. For Belgium or Italy one of dem journey go end for dis round. Dis na everything you need to know about di team news, match facts and predictions Belgium get injury wahala for dia team to some of dia key players, Kevin de Bruyne and Eden Hazard fitness get as e bit as e be like say dem fit no play sake of di injury wey dem get for dia last-16 victory over Portugal. Dia defender Timothy Castagne don re-join di squad afta im injure im eye socket, but e dey unlikely say im go play. While for Italy Giorgio Chiellini fit dey available again afta e miss di last two games wit muscle injury. Defenders Alessandro Florenzi don return to training with di squad afta im get calf issues. Dis na di biggest game of di round and di bad news for Belgium na say Kevin de Bruyne and Eden Hazard no go dey fully fit sake of di injury wey dem get for dia win against Portugal. I bin dey impressed by di way Belgium take win di game, but dis go be anoda ogbonge test for dia defence. Of all di teams wey remain for di tournament, di one wey I like for every department na Italy. If you look back for every major finals wey I fit remember, di eventual winners dey always get one knockout game wia dem no really play well and dem still go through. If Italy pass dis tie, however dem take do am, then dem get great chance of winning di whole tin. I no think say dem get many weaknesses. Prediction: 1-2 Head-to-head Dis na di fifth match between dis two sides for major tournament, but di first for knockout stage. Italy don win three of di previous four matches for a major tournament, dem draw di oda one. Italy 2-0 win for Lyon for di group stage for Euro 2016 na dia most recent game against Belgium. Emanuele Giaccherini score afta 32 minutes before Graziano Pelle add a second goal for injury-time. Belgium For 2016, Wales knock Belgium out for di quarter-finals, dem lose di game 3-1. Dem bin don win 11 of dia last 13 games (D2), score 32 goals and concede eight. Belgium don lose just one of dia last 27 games (W23, D3). Dia only defeat since di start of 2019 na di 2-1 loss to England for Wembley for di Nations League for October. Dem don score for each of dia last 34 games, di last time dem fail to score na dia 1-0 defeat to France for di 2018 World Cup semi-final. Since Roberto Martinez first game in charge for September 2016, dem don win more games (47) and scored more goals (175) than any oda European nation. Thorgen Hazard don scor four goals and two assists for im last seven starts. Italy Italy don reach di European Championship quarter-finals for the fourth tournament in a row. Three of dia most recent quarter-final appearances don end for penalty shoot-out - wia dem lose to Spain for 2008, dem beat England for 2012 and lose to Germany for 2016. Italy don win a national record 12 games in a row, scoring 34 goals and conceding only one. Dem dey unbeaten for a national record of 31 games (W26, D5) since dem lose 1-0 to Portugal for di Nations League for September 2018. Dem concede dia first goal since October for extra time against Austria, wey end dia run of 19 hours and 28 minutes without conceding. Matteo Pessina fit become di first Italian player to score for three consecutive matches for di Euros. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57700435 +sports Transfer deadline day - Players wey don strike deals "Some English Premier League clubs don confam di signing of new players for di last day of di transfer window. English Premier League and Football League transfer window closes at 23:00 BST Meanwhile di Transfer windows dey close for Germany by (17:00 BST), Italy (19:00 BST) and Spain (23:00 BST) Manchester City, Manchester United Leicester, Nottingham Forest na some of di clubs wey don announce new dia signing on Thursday. See di deals wey don happun so far today for dis tori. Man United don sign Brazil winger Antony from Ajax for an initial fee of 95m euros (£82m). Di deal, wey include a potential 5m euros of add-ons, na di fourth most expensive signing for Premier League history. Di 22-year-old sign contract until 2027, wit di option of an additional year. Martin Dubravka don join Manchester United on a season-long loan from Newcastle United, di deal dey subject to registration. Di goalkeeper go spend di 2022/23 season for United wit di option to make di transfer permanent. Manchester City don sign Switzerland defender Manuel Akanji on a five-year deal. Di 27-year-old join from Borussia Dortmund, wia im make 158 appearances since January 2018. Akanji get 41 caps for Switzerland and play a key role for dia qualification for World Cup. Leicester City don sign defender Wout Faes from French club Reims. Di 24-year-old dey come in as a replacement for Wesley Fofana, wey join Chelsea for about £70m on Wednesday. Faes joined on a five-year contract for an undisclosed fee, di move dey subject to international clearance. Nottingham Forest don sign Ivory Coast defender Willy Boly from Wolves. Di left-footed centre-back, wey fit play for a back three or four, sign a two-year deal and na Forest 19th first-team signing of dis summer. Chelsea manager Thomas Tuchel dey back Pierre-Emerick Aubameyang to ""create his own history"" for di number nine jersey for Stamford Bridge. Aubameyang, wey 33 years, join di Blues for £10.3m from Barcelona on deadline day. Fulham don complete di signings of Willian on a free transfer. Willian arrival don take di number of players for di Premier League club dis summer to nine. Ex-Chelsea and Arsenal midfielder Willian, wey be 34 years, been dey play wit Corinthians. Fulham don complete di signing of French defender Layvin Kurzawa from Paris St-Germain on a season-long loan. Di 29-year-old left-back don make 153 appearances for di French champions since im arrive from Monaco for 2015 but e neva play for dem dis season. ""I feel very, very happy to dey here. Na family here, everyone dey very cool,"" e tok for di club website. Aston Villa don agree a £13m deal for Wolves midfielder Leander Dendoncker. Di Belgian, wey be 27 years old, no dey Wolves' plan and Villa manager Steven Gerrard dey keen to strengthen im squad afta dia poor start to di season. Villa dey also close to signing Southampton defender Jan Bednarek, wey be 26 years, on loan, as cover for Douglas Costa wey get injury. Oriol Romeu don end im seven-year stay wit Southampton to join La Liga side Girona on a three-year deal. Di Spanish midfielder, wey be 30 years, play 256 games for Saints and scored eight goals. ""Oriol leave wit di very best wishes of everybody for Southampton,"" na so di Premier League club tok. Everton don re-sign midfielder Idrissa Gueye from Paris St-Germain on a two-year deal for a fee of about £2m. Di Toffees bin don dey to bring  back di 32-year-old to Goodison Park since di start of last month. PSG bin sign di Senegal international Gueye from Everton for about £30m for 2019. Benfica don sign attacking midfielder Julian Draxler from Paris St-Germain on a season-long loan. Di Germany international, 28, move to PSG for 2017 for a £35.5m deal and e win four Ligue 1 titles for France. Still dey refresh dis page - we dey update dis page wit more Transfer deadline day updates as e dey hot..." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd129gpyjw1o +entertainment PCOS: Keke Palmer Polycystic Ovarian Syndrome struggle and oda celebs like Lea Michele, Harnaam Kaur wey don open up "American actress Keke Palmer don reveal say she get Polycystic Ovarian Syndrome, (PCOS). On Tuesday, di star comot for inside social media to tok about di journey for her to find di diagnosis. She bin tok about how her pimples bin lead am to find out wetin be di root cause of wetin bin dey do am. She tok say na afta her colleagues bin even try give her money to fix am, she say she bin even go hospital, but dem bin no even see am as PCOS, say 'one doctor cari measles vaccine give me.' She tok say she begin to dey research her family on top say dem get history with diabetes and cari di diagnosis go doctor. PCOS na hormonal sickness wey dey affect women of reproductive age. Women wey get PCOS fit get irregular menstrual periods or plenty male hormone (androgen) levels, dis one mean say dem get plenty man blood for dia body. Oda celebrities wey don comot say dem get di syndrome include Glee star, Lea Michele discuss her own journey with PCOS for 2019 say di side effects like weight gain and bad skin ""fit dey brutal."" Di mama of one, tok say she bin get diagnosis wen she bin dey enta her 30s. She say e hide because she bin dey take birth control. She say with beta diet she don control am and say ""her own sef no too bad, pipo dey wey worse pass me."" Harnaam Kaur na PCOS patient wey her condition make her start to dey grow bia-bia as teenager. For one interview, she reveal say she bin dey wax her face and e make her skin to dey rough and even sef parts of her skin go tear comot. She don turn to body positivity activist and model say she no go allow her bia-bia to tiff her womanhood. Emma Thompson suffer from infertilty and e bin dey very stressful to born her pikin, Gala. She tok for interview say e bin dey pain her wella wen she see pipo dey waka with dia pikin dem. Source: NHS" https://www.bbc.com/pidgin/tori-55155785 +business Onitsha market fire: 'I lose my retirement moni afta 30 years of savings' "Retired banker Mrs Nkiru Ukwu save all her moni, open shop for Ochanja market, Onitsha Anambra state wit hopes say she go see moni take feed her five children. But dat dream don kpafuka afta serious fire burn down her shop completely on Wednesday, October 17 2019. Di fire bin start afta tanker wey carry petrol fall down come burn Ochanja and Relief markets. Di retired banker wey bin dey in very sad mood, manage follow BBC Pidgin tok. She say, ""I buy shop for one of di plaza inside di market wit three million naira, come even stock my shop for dis coming Christmas season wit two million naira. I bin work for bank for thirty years, na my gratuity and savings I take start di business."" As our tori pesin dey follow Mrs Ukwu dey tok, she break down, begin cry, dey scream say all her gratuity don go like dat. She say she no know wia she go even start from. Very small part of her market still dey come from China and her pikin dey plan to use social media sell am but she say di moni no go too reach anywia. Ebere Ekeopara, our reporter wey dey ground for Onitsha describe how pipo dia dey vex say goment no come to epp dem during di fire and how sadness full everiwia because of di plenti loss of life and property. One man tell Ekeopara say im still dey find im younger brother one day afta di fire, as e no dey ansa im phone. Di man say im call di younger brother wey dey inside di market to comot sharparly, but di response im brother give am say na im wan quick open di safe inside dia shop upstairs so that e go use am buy glue di next week. Di man say now im now know if im younger hear word to come down or e burn inside fire because nobodi dey pick when e call. Our reporter also hear di tori of one woman wey die inside di fire with her pikin. Right now, e no dey clear how many pipo die as goment officials never confam. And frustration dey build for di minds of pipo wey dey di area of di incident. Our reporter say she visit di upper Iweka fire service wey dem dey tok as na im dey near Ochanja, but e dey under lock and key and staff don run comot. Di pipo tok say dem ready to burn down di fire service office along wit anybody wey show face. Tori be say na poo-poo from two trucks wey dey go on dia own dem kolobi to epp quench one of di fire - as na different different parts of di market bin dey burn." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50091510 +sports Algeria Vs Sierra Leone Group E Afcon 2021 game end in goalless draw Algeria Vs Sierra Leone end in a goalless 0-0 draw for Douala Stadium for Cameroon afta dem jam for dia first African Cup of Nations, Afcon 2021 encounter. Algeria na di defending champion and get Man City star Mahrez Riyad bin dey part of di team. First Half 5mins: Kwame Quee (Sierra Leone win free kick for di defensive half. Foul by Yacine Brahimi (Algeria). Corner, Sierra Leone. Na Abdelkader Bedrane concede am. Attempt missed. Islam Slimani (Algeria) right foot shot from difficult angle on di right dey close, but e miss am to di right. E dey assisted by Riyad Mahrez with a through ball. Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) win free kick for di attacking half. Foul by Youcef Atal (Algeria). 10mins: Missed attempt. Alhaji Kamara (Sierra Leone) right foot shot from di centre of di box. Foul by Umaru Bangura (Sierra Leone). Islam Slimani (Algeria) win free kick on di left wing. Corner, Algeria. Na Umaru Bangura concede am. Youcef Belaïli (Algeria) right foot shot from outside di box dey blocked. Cornerfor Algeria. Alhaji Kamara concede am. 15:mins: Foul by Alhaji Kamara (Sierra Leone). Ramy Bensebaini (Algeria) win free kick for di defensive half. Kei Kamara (Sierra Leone) win free kick for di defensive half. Foul by Ramy Bensebaini (Algeria). 20mins: Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) win free kick on di left wing. Foul by Riyad Mahrez (Algeria). Attempt missed. Alhaji Kamara (Sierra Leone) header from di centre of di box dey close, but e miss am to di right. Na Mustapha Bundu assist with a cross afta a set piece situation. Attempt saved. Youcef Belaïli (Algeria) right foot wey e shoot from outside di box dey saved for di centre of di goal. E dey assisted by Haris Belkebla. Kei Kamara (Sierra Leone) win free kick for di defensive half. Foul by Haris Belkebla (Algeria). 25mins: Osman Kakay (Sierra Leone) win free kick for di attacking half. Foul by Ramy Bensebaini (Algeria). 30mins: Attempt missed. Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) right foot shot from outside di box dey too too high. Kei Kamara na im assist am. Attempt saved. Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) right foot shot from outside di box dey saved for di bottom left corner. Offside, Sierra Leone. Mustapha Bundu try with a through ball, but Alhaji Kamara dey offside. Corner, Algeria. Na Kevin Wright concede am. Mustapha Bundu (Sierra Leone) win free kick on di right wing. Foul by Abdelkader Bedrane (Algeria). 35mins: Abdelkader Bedrane (Algeria) collect yellow card for a bad foul. Attempt missed. John Kamara (Sierra Leone) right foot shot from di right side of di box dey too high. Foul by Osman Kakay (Sierra Leone). Youcef Belaïli (Algeria) win a free kick on di left wing. Attempt dey blocked. Youcef Belaïli (Algeria) right foot shot from difficult angle and long range on di left dey blocked. 40mins: Attempt missed. Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) right foot shot from di left side of di box dey high and wide to di right. E dey assisted by Kei Kamara. 45mins: Corner for Algeria. Na Kwame Quee concede am. Offside, Sierra Leone. Kevin Wright try with a through ball, but Alhaji Kamara dey caught offside. HALF TIME! Algeria 0, Sierra Leone 0. Second half Second Half begins Algeria 0, Sierra Leone 0. 45mins: Substitution, Algeria. Djamel Benlamri replace Abdelkader Bedrane. Foul by Alhaji Kamara (Sierra Leone). Youcef Belaïli (Algeria) win free kick for di defensive half. Offside, Sierra Leone. Mohamed Buya Turay try a through ball, but e catch Alhaji Kamara offside. Attempt missed. Mustapha Bundu (Sierra Leone) right foot shot from more dan 40 yards on di right wing miss to di left. E dey assisted by Osman Kakay. 50mins: Attempt dey blocked. Yacine Brahimi (Algeria) right foot shot from di centre of di box dey blocked. E dey assisted by Youcef Belaïli. Kei Kamara (Sierra Leone) win free kick for di defensive half. Foul by Djamel Benlamri (Algeria). Foul by John Kamara (Sierra Leone). Yacine Brahimi (Algeria) win free kick for di defensive half. Attempt saved. Yacine Brahimi (Algeria) right foot shot from di centre of di box dey saved for di centre of di goal. E dey assisted by Riyad Mahrez with a through ball. Osman Kakay (Sierra Leone) win a free kick for di defensive half. Foul by Youcef Belaïli (Algeria). Attempt missed. Kei Kamara (Sierra Leone) right foot shot from di right side of di box dey close, but miss to di right. 55mins; Corner, Algeria. wey Kevin Wright concede. Corner, Algeria. Steven Caulker concede am. Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) win free kick on di left wing. Foul by Youcef Atal (Algeria). Umaru Bangura (Sierra Leone) win free kick for di defensive half. Foul by Yacine Brahimi (Algeria). 60mins: Haris Belkebla (Algeria) win free kick for di defensive half. Attempt saved. Yacine Brahimi (Algeria) right foot shot from outside di box dey saved for di centre of di goal. Assisted by Riyad Mahrez. Substitution - Farid Boulaya replaces Sofiane Feghouli. 65mins: Substitution, Algeria: Sofiane Bendebka replaces Yacine Brahimi. Baghdad Bounedjah replaces Islam Slimani. Kwame Quee (Sierra Leone) win free kick for di defensive half. Youcef Belaïli (Algeria) wins a free kick in the attacking half. Attempt blocked. Sofiane Bendebka (Algeria) left foot shot from di centre of di box dey blocked. Corner, Algeria. Steven Caulker concede am. Attempt saved. Riyad Mahrez (Algeria) left foot shot from outside di box dey saved form di bottom left corner. 70mins: Offside, Algeria. Sofiane Bendebka try one through ball, but e catch Youcef Belaïli offside. Mohamed Buya Turay (Sierra Leone) win one free kick on di left wing. Foul by Youcef Atal (Algeria). Corner, Sierra Leone. Ramy Bensebaini concede am. Corner, Algeria. Na Kei Kamara concede am. 75mins: Attempt missed. Baghdad Bounedjah (Algeria) header from di centre of di box afta a corner. Substitution, Sierra Leone. Saidu Fofanah replace Alhaji Kamara because of injury. Foul by Umaru Bangura (Sierra Leone). Farid Boulaya (Algeria) win free kick on di left wing. Umaru Bangura (Sierra Leone) collect yellow card for a bad foul. Attempt blocked. Sofiane Bendebka (Algeria) left foot shot from di left side of di box dey blocked. E dey assisted by Youcef Belaïli with a through ball. 80mins: Attempt saved. Riyad Mahrez (Algeria) right foot shot from di right side of di box dey saved for di bottom left corner. E dey assisted by Baghdad Bounedjah. Corner, Algeria. Na Mohamed Nbalie Kamara concede am. Attempt missed. Aïssa Mandi (Algeria) right foot shot from a difficult angle on di right miss to di right. E dey assisted by Youcef Belaïli with a cross afta one corner. Foul by Kei Kamara (Sierra Leone). Djamel Benlamri (Algeria) win free kick for di defensive half. 83' Substitution, Algeria. Saïd Benrahma replaces Haris Belkebla. 84' Substitution, Sierra Leone. Sulaiman Kaikai replaces Mohamed Buya Turay. 85mins: Attempt missed. Saïd Benrahma (Algeria) right foot shot from di centre of di box miss to di left. E dey assisted by Youcef Atal with a cross. Foul by Mustapha Bundu (Sierra Leone). Saïd Benrahma (Algeria) win a free kick for di attacking half. Attempt missed. Baghdad Bounedjah (Algeria) left foot shot from di centre of di box miss to di right. E dey assisted by Youcef Belaïli afta a set piece situation. Foul by Kwame Quee (Sierra Leone). Sofiane Bendebka (Algeria) win free kick for di defensive half. Offside, Algeria. Youcef Belaïli try a through ball, but Baghdad Bounedjah dey caught offside. Kei Kamara (Sierra Leone) win a free kick for di attacking half. Foul by Djamel Benlamri (Algeria). 90mins: Attempt saved. Ramy Bensebaini (Algeria) right foot shot from di left side of di box dey saved for di centre of di goal. E dey assisted by Djamel Benlamri. Attempt blocked. Saïd Benrahma (Algeria) right foot shot from di right side of di box dey blocked. E dey assisted by Riyad Mahrez. Corner, Algeria. Na John Kamara concede am. Attempt saved. Baghdad Bounedjah (Algeria) header from di centre of di box dey saved for di centre of di goal. E dey assisted by Youcef Belaïli with a cross. 90'+4' Full Time Second Half end, Algeria 0, Sierra Leone 0. Formation 4-4-2 23 M'Bolhi, 20 Atal, 2 Mandi, 17 Bedrane, 21 Bensebaini, 7 Mahrez,12 Belkebla, 8 Belaïli,11 Brahimi, 13 Slimani, 10 Feghouli Substitutes 4 Benlamri, 5 Tougai, 9 Bounedjah, 14 Bendebka,15 Boulaya,16 Oukidja,19 Zorgane, 24 Chétti, 25 Benayada, 26 Amoura, 27 Benrahma, 28 Halaimia Formation 4-2-3-1 1 Nbalie Kamara 2 Kakay 5 Caulker 17 Bangura 3 Wright 7 Quee 6 Kamara 19 Bundu 10 Kamara 14 Buya Turay 12 Kamara Substitutes 4 Kamara 8 Fofanah 9 Williams 11 Kaikai 15 Dunia 16 Sesay 20 Mansaray 21 Kanu 22 Kallon 23 Caulker 27 Dumbuya 28 Kamara Referee: Ahmad Heeralall https://www.bbc.com/pidgin/tori-59954473 +health Coronavirus: Covid-19 palliative 4000 bags of ‘Njoh’ rice dey 'scatter' Cameroon "Cameroon di scatter as kontri pipo di kweshion how health Minister, Manaouda Malachie share 4000 bags of rice. For helep goment fight Covid-19, some good heart pipo and companies di dash goment moni, chop, hand sanitisers and chloroquine tablets and oda tins. For March, ORCA, (company weh e di deal wit furniture and decoration for house) bi dash goment 4000 bags for rice. For dat taim kontri pipo bin joke say, e for good for cook de rice before deh give'am for goment because deh go 'tief'am. Since 21 July, some kontri man send tweet for Health Minister, ask e how e do wit de 4000 bags of rice. Na so, Manaouda Malachie komot paper how deh share de rice for de ten regions for kontri for make'am clear say e nova tief, de rice. ""Ah wan make e bi clear how deh bi share dis rice for April 29, Manaouda Malachie tweet. Minister say afta meeting wit Territorial Administration, Social Affairs, Women Empowerment and Family ministers, deh consider population for each de ten regions before deh share de rice. Na centre region get de highest, 800 bags of rice, Northwest and Southwest regions get 300 bags each. Regional governors bin suppose take de rice from Yaoundé to dia regions by May 1, den share'am for 'vulnerable'-suffer pipo. Just now some kontri pipo say deh nova even see empty bags, odas, di wanda who take de rice for dia regions. But oda congratulate Manaouda Malachie say na transparent minister. No bi only rice, kontri pipo di suspect, as deh also suspect mago-mago for how health ministry di manage moni weh deh dash goment for fight Covid-19. Corruption di climb ceiling for Cameroon, number 153 out of 180 for 2019 Transparency International corruption index." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53511009 +sports Newcastle vs Arsenal highlights: Ben White own goal, Bruno score, Arteta bring Lacazette, Martinelli, Pepe but Gunners still lose Arsenal hopes of finishing for di top four of di Premier League hit rock as dem lose 2-0 to Newcastle for St James' Park. Mikel Arteta side bin need to win to move above Tottenham into fourth and put dem for better position to secure a Champions League spot ahead of di final match of di season dis weekend. But dem end di game as second best throughout and fall behind early for di second half wen Ben White score own goal. Bruno Guimaraes round up di game wit di second goal. Arsenal no perform well for di match. Newcastle suppose score more goals. Di gunners dey fifth position. Second half don start; 45 mins: Newcastle 0-0 Arsenal 45+1: Schar go down wit injury afta e clash wit for a 50-50 ball wit Nketiah. 48 mins: Substitution. Newcastle remove Schar bring in Lascelles afta di concussion assessment. 50 mins: Foul. Xhaka set leg for Almiron wey wan run pass am. 53 mins: Substitution. Smith Rowe enta for Martinelli. 53 mins: Goal! Callum Wilson put Newcastle ahead. Dis na im first goal of the year. Newcastle 1-0 Arsenal 62 mins: Arsenal try press but e end wit poor finish from Martinelli. 63: Substitution. Arsenal bring in Lacazette for Tavares. 69 mins: Newcastle left-back Matt Targett go down wit injury and Kieran Trippier dey warm up just in case. 73 mins: Newcastle counter attack wit Krafth wit so much space. 74: Substitution. Pepe replace Gabriel. 76 mins: Substitution. Newcastle make two changes. Murphy and Fraser enta to replace Almiron and Saint-Maximin. 80 mins: Pepe lose ball wey e suppose pass come allow Newcastle players collect ball run dem on counter. But Ramsdale save di shot from Murphy. 82 mins: Wilson hit ball from 40 yards to score as e notice say Ramsdale dey outside di box. 85 mins: Goal! Newcastle 2-0 Arsenal. Bruno score from rebound. 89 mins: Arsenal top four hope don turn to smoke. Newcastle 2-0 Arsenal 90 mins: Saka move into dangerous position about 20 yards out but e no end move wit beta effort. 6 mins added time. 90+2: Arsenal just dey misplace passes all over. 90+3: Substitution. Newcastle comot Wilson bring in Dwight Gayle. 90+6: Newcastle almost score di third goal. Ramsdale save shot from Fraser. Full Time; Newcastle 2-0 Arsenal Kick off, First half; Match don start Arsenal fit go back to di top four? 2 mins: Newcastle 0-0 Arsenal 4 mins: Offside. Almiron show im usual speed to force di ball go front. 6 mins: Arsenal attack wit Nketiah. Elneny follows up im short wey Newcastle defender block go corner. 7 mins: Arsenal cut out ball into Callum Wilson and start counter-attack wey end wit anoda shot from Eddie Nketiah. 8 mins: Beta first touch by Newcastle left-back Matt Targett to control cross-field ball and nutmeg Takehiro Tomiyasu. 12 mins: Offside! Wilson don get three offside already for di match already. Joelinton give am pass from back. 13 mins: Lively start by di Magpies. Dia fans dey ginger. Newcastle 0-0 Arsenal 15 mins: Saint-Maximin get im first chance to run to Tomiysau. 16 mins: Everytin look easy for Newcastle at di moment. 18 mins: Almiron miss chance to score afta pass from Bruno from di side in di box. Arsenal keeper Ramsdale parry di ball. 19 mins: Arsenal clear ball from di corner. Xhaka win di first ball. 21 mins: Arsenal get put Saka for one-on-one wit Targett afta beta one-two pass wit Odegaard inside di box. 24 mins: Newcastle keeper save anoda shot from Saka again. 25 mins: Arsenal don try stabilise di game for some minutes now, but Eddie Nketiah enta offside as e run into Bukayo Saka ball. 27 mins: Almiron run back but di ball comot from im leg towards Gabriel but Newcastle win di first contact and complete the clearance. 30 mins: Newcastle get back to back corner. Targett find di right delivery but Joelinton no dey enof to keep di ball. 31 mins: Bukayo Saka clear di corner but Newcastle win di ball back. 33 mins: Saint-Maximin show dey worry Arsenal wit im pace but Tomiysau dey try hold am down. 36 mins: Ramsdale save shot from Saint-Maximin from di left. Di shot from 20 yards go corner. 38 mins: Tomiysau be like e don get injury. E dey hold im hamstring. Cedric dey warm up. 39 mins: Substitution for Arsenal. Cedric enta for Tomiysau. 41 mins: Newcastle don really push Arsenal go back. Dem don take control of di game. 43 mins: Aaron Ramsdale punch cross from corner comot but Newcastle collect di ball again. Di Magpies dey hold di possesion 70%. Half Time; Newcastle 0-0 Arsenal Arsenal don win 18 of dia past 19 league and cup meetings wit Newcastle. Except for a 2-1 league defeat wey dem suffer for St James' Park for April 2018. Newcastle don play seven competitive games without scoring against Arsenal since Ciaran Clark 91st-minute consolation effort wia dem suffer 2-1 defeat for di Premier League home defeat for September 2018. A win for di Monday night match go carry Newcastle go 46 points, dia highest tally since returning to di Premier League five years ago. Victory go also ensure say dem reach 30 top-flight points for home in a season for di first time since 2011-12. Di Gunners don record five wins and five defeats for dia past 10 Premier League fixtures. Dem dey one short of equalling di club record for most Premier League defeats of a 38-game season: 13, wey dem set for 2017-18 and 2020-21. Arsenal don win eight league matches without clean sheet since dia 1-0 win at Aston Villa on 19 March. Newcastle United: Dúbravka, Krafth, Schär, Burn, Targett, S Longstaff, Guimarães Rodriguez Moura, Joelinton, Almirón, Wilson, Saint-Maximin. Arsenal: Ramsdale, Tomiyasu, White, Gabriel, Tavares, Elneny, Xhaka, Saka, Ødegaard, Smith Rowe, Nketiah Arsenal endure a horrible night on Thursday for di north London derby but dem no fit allow dat one affect dem. E dey typical of Arsenal to easily collapse wen sometin go against dem - sometimes dem be like say dem dey strong mentally but no be so. Dem dey under pressure now. Arsenal must win for St James' Park or dem go finally comot from fourth place. Newcastle don improve well well over di past few months and dem don show strength for dia home for St James' Park. To beat dem dia go hard. Prediction: 1-1 Dey refresh dis page for live update of di match https://www.bbc.com/pidgin/sport-61470238 +entertainment DJ Cuppy reveal she meet her husband-to-be, Ryan Taylor 25 days before e propose "Ogbonge Nigerian Disk Jockey and daughter of billionaire businessman Femi Otedola, DJ Cuppy wey her real name be Florence Ifeoluwa Otedola don reveal say she and her fiance bin meet only 25 days ago. DJ Cuppy drop di informate for her social media platforms on Monday night days after photos of how her lover, British boxer Ryan Taylor propose to her for UAE hit di internet. Since di news enter public space di lovebirds don also continue to share romantic photos from different hangout for social media. Talking about how she take find her love, DJ Cuppy inside one Twitter post on Monday night say ""I fit officially announce say I don dey engaged."" She write. She add say she meet her bobo for one driving event wey happun for Abu Dhabi between 12-20 November. Cuppy tok say dia meet never reach one month before Ryan propose to her and she accept im marriage proposal. ""Only 25 days ago during @Gumball3000 driving rally, I meet di love of my life.\n\nSometimes you fall for di MOST unexpected person for di MOST unexpected time and for di MOST unexpected reason.\n\nI love you deep @RyanTaylor."" She tweet"" Cuppy latest tweet dey come as one video dey trend for social media about anoda girl wey dem claim be Ryan lover. While some pipo wey be Cuppy fans and followers for social media dey congratulate her, odas dey worry say she quick Ryan marriage proposal. Some say dem hope say di boxer no go serve her breakfast, even someone wey say she counselor offer to do premarital counseling for her. Ryan Taylor na British Boxer wey become popular sake of im Youtube page. For YouTube, di 29 year old dey feature plenti videos wey include pranks but especially BMX riding. For 2019, Taylor enta gbege for di pranks wey im bin dey pull afta im sneak enta di Celebrity Big Brother house with anoda YouTuber Ally Law wey gbab dem 120 hours community service and fine of £1,235. Ryan Taylor currently get 2.4 million subscribers for im YouTube wey im bin start for November 2011. E also get link with Burna Boy, wey im reveal say sneak am enta di O2 Arena afta dem don ban am for life for dia.For im boxing career, Ryan Taylor don fight against Slim Albaher for October. For March 2022, dem disqualify am for one celebrity Boxing match afta im headbutt im opponent DK Money. E get one son according to informate on im Instagram page. DJ Cuppy no need too much introduction to many pipo for Nigeria and even across Africa.DJ Cuppy aka Ifeoluwa Florence Otedola na di daughter of Nigerian billionaire Femi Otedola, but she don manage to build a brand for herself away from her papa billions.She tok say she be DJ, artiste, philanthropist and student. She recently her second degree for Oxford University for UK. DJ Cuppy bin popular for di Nigeria music scene sotay she as DJ make hit song with Zlatan wey dem call Gelato. She don perform for plenti event wey include di 2014 MTV Africa Music Awards and fashion shows among odas. She dey popular for her love of pink and her social media doings. So dis coupling shock plenti pipo as earlier dis year she bin hala say, 'I no get boyfriend - Di street dey rough'." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c51g9y458jeo +entertainment MTV EMA 2021 winners: Wizkid win 2021 MTV Europe Music Awards Best African Act "Ogbonge Nigerian musician Wizkid don win di Best African Act award for di 2021 MTV Europe Music Awards. Di Grammy award winner dey among winners of di (MTV EMA), wey happun for di Papp László Budapest Sportaréna for Budapest, Hungary on Sunday. Di Afrobeats superstar compete with oda African musicians, like Tems (Nigeria), Amaarae (Ghana), Diamond Platnumz (Tanzania) and Focalistic (South Africa), to win di award. Di singer enta im verified Twitter page to share im win wit im followers. E tweet ""Lagos to da world."" MTV Africa plus oda pipo don dey congratulate di artist for dis ogbonge achievement. Last week, e dey nominated for di Best African Music Act and Best International Act for di 2021 Music of Black Origin (MOBO) Awards for UK. Oda artists wey shine for di MTV EMAs award include Edsheeran and boyband BTS. Dem be di biggest winners for di award. Sheeran wey open di ceremony on Sunday, win best artist and best song for Bad Habits. BTS pick up four awards wey include best pop and best group. Best Artist" https://www.bbc.com/pidgin/tori-59302183 +business Coronavirus - Virus: Ghana cedi make gains against US Dollar sake of COVID-19 Disease? "Debate dey go on for Ghana say coronavirus dey make de cedi appreciate against de US Dollar. One of those wey support dis claim be National Democratic Congress, Communications Director, Sammy Gyamfi who argue say coronavirus help de cedi appreciate sake trade volumes between Ghana den China reduce. Therefore importers shun dey go buy goods from China sake of de deadly virus. De result be say menerz dey dema dollars for de country inside, reducing de pressure on de cedi. As at today 2 March, 2020 de Ghana Cedi dey exchange 5.32 to one US dollar. In fact, as of December 2019 de Cedi dey exchange for 5. 7 while by January 2020 de cedi to dollar exchange for 5.48 and by mid February 2020 wen de deaths from coronavirus boku, de Cedi exchange for 5.41 to one US dollar. BBC Pidgin talk to some Ghanaians for Accra who feel say coronavirus help de cedi. ""Right now with de coronavirus Ghana no go buy goods from China, so dis go save plenty money for de economy inside which go make de cedi appreciate."" Ellis talk BBC Pidgin. Although some policy analysts also agree plus dis position say coronavirus get positive impact on Ghana cedi, but Economist for University of Ghana, Professor Godfred Bokpin dey disagree. ""De evidence no dey support de claim say de appreciation of de cedi be solely due to coronavirus"" Professor Bopkin talk BBC Pidgin. ""Ghana exposure in terms of trade volumes to China be high but other African countries like Nigeria, South Africa, Zambia, the Ghana no be unique."" From that perspective you no fit attribute de appreciation of de cedi to de Ghana cedi. According to Professor Bokpin, ""if you check de data, de appreciation of de Ghana cedi start before de announcement of coronavirus. De cedi recovery start before dem declare an global health issue."" ""What dey happen be Bank of Ghana en strategic intervention. Central Bank sheda build dema reserves so say of Ghana sheda shore up dema reserves in preparation for 2020"" he add. Data from World Integrated Trade Solutions dey show de 2018 trade volumes of four African countries. South Africa imports from China worth US$ 17,087 million. Nigeria imports from China worth US$ 8,349 million. Ghana imports from China worth US$ 2,273 million. Zambia imports from China worth US$ 1,291 million. What be key about de above data be say although South Africa den Nigeria get higher trade volumes plus China compared to Ghana. Dema currency since de inception of coronavirus depreciate except Ghana who see appreciation of de currency from 5.7 per dollar around December last year to 5.32 around February ending." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51708967 +politics Bayelsa election: APC, Lyon use Jonathan to cover dia rigging - Dickson "Bayelsa State Govnor Seriake Dickson don lament say wetin happun on 16 November no be election, but say di Nigerian goment, security agency and INEC join hand to do magomago. Govnor Dickson wey don dey lead di state since 2012, use Facebook Live video to reject di tok say former presido Goodluck Jonathan no do well wen im receive rival party APC members, as guest for im house. Tori bin comot say katakata don ready to burst ontop Jonathan head because of 'anti-party' activities and say di Peoples democratic Party go comot am from di party. Inside di press conference wey Dickson do for state house on Tuesday, one tori pesin ask di former Senator wetin im feel about how Jonathan dey do padi padi with party rivals, and Dickson reply say ""David Lyon know say di former president no be di one wey contribute to di rigging"" ""But wetin dem do be say dem use di former president image to make am look like say division dey for di party, so as to make am easy to rig votes,"" na so oga Dickson tok. Di name of Pontius Pilate even come up afta Dickson accuse Lyon say wen im do bad bad tins finish, di plan na to wash im hand comot for Jonathan domot, just like di Roman govnor from Bible times. Di PDP tok-tok pesin confam to BBC Pidgin on Tuesday say officially di party no fit react now to di Jonathan mata, until di next day when dem meet to discuss everi-everi about di election. For di 16 November govnorship election, David Lyon of All Progressives Party win to put end to PDP 20-year rule for di state. INEC go issue certificate of return to Lyon on 21 November for di state capital, Yenogoa. We try to reach di APC publicity secretary for Bayelsa Doifie Buokoribo for reaction, but im phone dey off." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50463489 +sports Hafthor Bjornsson: Game of Thrones actor breaks world deadlifting record "Game of Thrones actor, Hafthor Bjornsson don set world deadlifting record as im lift 501kg (1,104lb). Bjornsson, wey be powerlifter play di role of Ser Gregor ""Di Mountain"" Clegane for di HBO series, break di record for Im own gym for Im hometown, Iceland. He lift di barbell for two seconds, before im drop drop di weights. Na sports broadcaster ESPN stream di event and dem film am for Bjornsson's YouTube channel. Bjornsson, wey be 2.05m tall (6ft 9in), bin win di World Strongest Man competition for 2018. As im dey tok for di ""behind-di-scenes"" video wey Im post for YouTube, Bjornsson say: ""I dey extremely proud, you know. I dey extremely happy. ""E dey great - nothing better pass make you prove pipo wrong. so many pipo don tok say, '501kg no go ever go up'... But I also get plenti support."" He add am: ""I feel healthy, I feel god. I just dey speechless, even though I dey talk too much now, But I dey happy-Dis na big deal for me Na Eddie Hall, one British man who become di first" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52519503 +entertainment Who be Chika Ike, wey clear di air about her relationship wit Regina Daniels husband Ned Nwoko "On Monday 14th September Nollywood actress Chika Ike come out to deny tori wey bin dey fly up and down say she dey date fellow actress Regina Daniels husband, Ned Nwoko. Chika post for her social media page say she no dey date di billionaire for inside her Instagram story as she bin dey ansa questions from her fans. One of di fans bin ask weda di Nollywood actress dey date Ned Nwoko and dey ready to be im seventh wife, but she tok say she no dey date am and na lie say she go be pesin 7th wife. Chika Nancy Ike na Nigerian actress, wey start her acting career for 2005, and tori be say she don act for ova hundreds of movies. She be two-time Africa Movie Academy Award nominee. For 2006, dem nominate her for best upcoming actress for di Africa Movie Academy Award and for 2008, dem nominate her again but dis time for best supporting actress. For 2011, di Nollywood actress launch her fashion line ""Fancy Nancy"" and open her fashion store wey she dey deal on female fashion cloths and accessories. Apart from acting, di actress get her own production company Chika Ike Production we dey produce television shows. Di rumour start some days ago, wen one video begin fly upandan for social media wey claim say Regina mama, Rita Daniels dey threaten Ike say she go show am pepper spiritually if she no stop to dey try to snatch her pikin husband. Rita sef later comot for Instagram to tok say di video na lie. To put di mata tor rest, Rita post on her social media page on Sunday say di video na forged video wey she no know anytin about. She further argue wit di claim by sharing di original version of di video." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54182750 +health Ghana international flights dey resume afta months of Covid-19 restrictions - See how you fit qualify to use di airports from now on Ghana dey join kontries like Ethiopia, Egypt and Senegal to open dia international airports to resume travel by 1st of September . President Nana Akufo-Addo na im order say make air, land and sea borders open again afta Ghana see drop in number of covid-19 cases. For ontop television on Sunday 30 August, 2020 Ghana President, Nana Akufo-Addo say all travellers must show proof say dem no get coronavirus as dem must present Covid- 19 test result wey read negative and neva pass 72 hours before dem comot di airport. Dem go also do anoda test wen dem reach airport and di result go comot within 30 minutes. Di passengers go pay for di test. Those wey test positive, go undego further assessment and treatment. All passengers go follow all di safety protocols wey include wearing of face mask wey dey compulsory. Airline wey no follow all goment directive go chop sanction. Cases of coronavirus don continue to dey drop for di kontri, di number of active cases na over one thousand inside di 44, 205 confamed cases. Usually for every week, around 24, 500 passengers na im dey enta Kotoka International Airport for Accra. Domestic flights bin don resume three months ago. But di kontri land and sea borders go still dey closed. Inside one televised address to di nation on Sunday 17 August, 2020 President Akufo - Addo say di decision to reopen di airport to international flights go depend on whether dem go fit test all di passengers wey enta di airport. Di move na prevent further spread of di virus in kontri. About twenty four thousand five hundred (24,500) passengers arrive for di Kotoka International Airport everi week. Domestic flights don alreadi dey operate for di west African kontri. Di president also announce further relax restrictions and reopening of higher schools alias tertiary institutions inside di kontri next week. Director General of di Ghana Health Service Dr Patrick Aboagye don tok say dem go do exercise ontop di mata dis week to know di kontri strength to test all di passengers as dem arrive. Dem dey consider adopting di covid-19 rapid testing system at for di airport next week. Covid-19 cases don see huge drop from over three thousand active (3,3007) cases inside di last three weeks to more than one thousand active cases (1,847) as of Saturday. Di kontri don so far cari out over four hundred thousand (427,121) covid-19 tests. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53971327 +sports Isaac Dogboe: Former World Champion AKA 'Royal Storm' wey be Ghanaian boxer make impressive comeback to winning ways plus 8th round TKO "Former World Champion, Isaac 'Royal Storm' Dogboe make massive comeback to winning ways after he knock out en opponent Chris Avalos from Mexico in de final round for MGM Grand, Las Vegas. Dogboe win de bout with technical knockout after en 14 months break from boxing. After de fight Royal Storm share message for tweeter top to thank Ganaians for de support. Before en break Isaac Dogboe record back-to-back losses to Emanuel Navarrete, who snatch en title from am. But dis time around, Royal Storm manage take en opponent to de full 8 rounds wey within 35 seconds to de end of de fight, combination of jabs from Dogbe make referee stop de fight - dis give am technical knockout. Isaac Dogboe in an interview plus ESPN, talk say ""It's been tough dis last 14 months…I thank God for my comeback, we still dey come back, we dey warm up."" In 2018, Isaac Dogboe win de WBO World Super Bantamweight title to become de Ghana's youngest world champion ever, he break record of former Ghanaian boxing great, Ike Quartey who win en first World championship at age 25. Dogboe make global headline with dis en win, even British press describe am as British-born Ghanaian boxer. But in December 2018, Dogboe lose en WBO title to Emanuel Navarette after en title contender dominte am. That be Dogboe en first defeat as professional boxer where he lose by unanimous decision. Dogboe san lose to Navarette in dema return match in May 2019 where dem give am technical knockout in de final round. Ghanaians attack British press over Dogboe De British press come under attack for Ghana after dem claim say di super bantamweight champion Isaac Dogboe be British. Mirror headline which read ""Isaac Dogboe is the British world champion you've never heard of - but all that is about to change"" spark debate for social media over attempts by some British who wan claim di boxing champion as British. Dogboe after en second loss, return to de gym for straight 14-months, he change en technical team, including en father as coach wey dem recruit new coach and trainers. Dogboe also move up from Super bantam weight division to Featherweight division were e say e dey feel comfortable in. Dis be Dogboe en first win after 14-mont break and de first as a Featherweight boxer." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53496577 +politics David Umahi: Ebonyi state governor mata wey court sack am from office afta e defect and wetin fit happun next "Reactions still dey follow di decision of di Federal High Court for Abuja wey sack di Ebonyi state Govnor David Umahi from office afta im defect or port go APC. Govnor Umahi for im reaction reject di ruling and say im go appeal di mata. ""We go file appeal against dis useless judEbonyi state Govnor, Dave Umahi say im go appeal di decision gement,"" Govnor Umahi tok, come add say: "" I still be di govnor of Ebonyi State."" On Tuesday, di Abuja High Court declare di porting of Ebonyi state govnor and im deputy govnor illegal, null and unconstitutional. Justice Inyang Ekwo make dis judgement based on case wey PDP file to ask for di removal of govnor and im deputy from office. Justice Ekwo give order to sack dem on di grounds say na PDP win di election on March 2019 no be di candidate. E quote section 221 of di constitution and immediately order di PDP to send names of pipo wey go replace dem to INEC to conduct fresh elections. For di ruling, di Justice also order INEC to stop to recognise David Umahi and Eric Igwe as Govnor and Deputy for Ebonyi State. But for press briefing wey di govnor do wit tori pipo, Umahi say di court no get di power to remove am from office. ""Na three ways any govnor fit comot for im seat, either by death, resignation or impeachment by di House of Assembly. No oda constitutional provision dey wey empower a hatchet man to turn di law and di constitution upside down , I don listen to di judgement of Ekwo and e dey obvious say im dey on a mission,"" Umahi tok. E add say, ""di ruling dis afternoon na clear evidence say dis kontri dey inside trouble"" One of Nigeria Senior Advocate of Nigeria (SAN), Mike Ozekhome, react to di Abuja high court decision to sack di govnor and im deputy. Oga Ozekhome say, ""Di judgement wey dem just deliver today, removing di govnor and deputy govnor of Ebonyi state and some lawmakers na bad judgement wey no fit pass di acid test of appellate jurisdiction becos di govnor and deputy govnor dey entitle to appeal and I no tink di court of appeal go uphold dis kain judgement."" SAN Ozekhome explain say di day dem swear pesin in as govnor or deputy govnor, dat day di pesin no longer belong to im political party. ""Im no longer be property of dat political party. Di vote wey make am govnor, na vote wey dem casr for am., not by one political party, but all di oda pipo including di ones wey no belong to any political party at all."" According to di Nigeria Constitution, once pesin become govnor, you only fit remove am in di following ways: Oga Mike Ozekhome (SAN) say aside from dis four ways wey constitution don already give, you no fit remove govnor for exercising im right to defect or port from one political party to anoda. Im add say: ""E fit dey painful, unconscionable or immoral for pesin to defect from part wey cari am enta power, but under our law, once pesin become govnor, e no longer belong to im party."" In line wit di Abuja Federal High Court order, PDP don submit di name of Iduma Igariwe and Fred Udogwu as govnor and deputy govnor of Ebonyi State to Independent National Electoral Commission (INEC). National chairmo of di party Iyorchia Ayu say dem select dem afta plenti consultation witin di party and in line wit di court order for di party to submit replacement for both di govnor and deputy seat. APC meanwhile don also reject di ruling as dem call am reckless. ""Di Presiding Judge commit judicial error by giving judgement wey sack a duly elected and sworn-in Governor and im Deputy without relying on or citing any provision(s) of di constitution of di Federal Republic of Nigeria or any provision of di Electoral Act wey empower di court to sack a sitting Governor and or im Deputy. Dis na purely error of justice,"" dem tok. Last month, federal high court for Zamfara strike out suit wey some Peoples Democratic Party (PDP) members bring unto say make court sack Govnor Bello Matawalle due to im defection to All Progressives Congress (APC). Di PDP members bin want make court sack Govnor Matawalle as dem believe say na PDP get di govnor seat and im defection to anoda party make am suppose vacate di govnor seat. According to di court, even though dem no get jurisdiction to listen to di case but di 1999 constitution no stop govnor from moving from one party to di oda. Judge Bappa Aliyu say Nigeria constitution give any govnor di freedom to move from one party to anoda as long as dat party dey operate legally within Nigeria. On 1st of August 2018, Sokoto state govnor announce im defection from di ruling APC to PDP for wetin e describe as 'prison yard' democracy wey di ruling party dey practice. APC sue di govnor go court asking am to vacate di seat because na di party own am. But notin comot form di mata as Govnor Tambuwal finish im term as govnor despite di challenge and still win second term as Sokoto govnor. Born David Nweze Umahi, im na two term govnor of Ebonyi state - e become govnor for 2015 under after e win di election on di platform of im former party, Peoples Democratic Party (PDP). E later join di All Progressive Congress (APC) for 2020. Umahi enta politics early and by 2007 e become di acting chairman of di Ebonyi State chapter of di PDP. From 2009 to 2011 e serve as state chairman of the party. Oga Umahi later serve for di governing board of di Federal Medical Centre for for one year." https://www.bbc.com/pidgin/60666049 +sports US Open 2019: Nadal don win im 19th Grand Slam title "Rafael Nadal don win im number 19 Grand Slam title. For match wey tie wrapper im win Daniil Medvedev for di US Open finals. Nadal win di match 7-5 6-3 5-7 4-6 6-4, for New York. Di 33 year old win against di 23-year-old Mdevedev for match wey bin dey only four minutes shorter than di longest US Open final for history wit 4hrs 50 minutes. Na one win now remain for Nadal to equal Roger Federer wey dey lead for number of Grand Slam victories. Afta im win Nadal tok say: ""E do be one of di most emotional nights for my tennis career. Na one kain amazing finals and e mad die."" Dis win make am ogbonge year for Nadal, wey reach three Grand Slam finals for di same year for di fourth time of im career." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49631857 +sports Serena Williams go play Bianca Andreescu for US Open final Serena Williams get another chance to win her 24th Grand Slam singles title afta she beat Elina Svitolina to reach US Open final. Serena power too much for Ukraine fifth seed as she win di match 6-3 6-1. Williams wey be di number eight seed dey eye her first Grand Slam win since she born for September 2017. Di 37 year old American wey don win US Open six times go play 19-year-old Bianca Andreescu from Canada for di final on Saturday for New York. Andreescu beat 22-year-old Swiss Belinda Bencic 7-6 (7-3) 7-5, to win di last five games of di match. Tori be say Andreescu, dey play for first time for US Open main draw and dey compete for her fourth Grand Slam tournament, dem born her nine months afta Williams win her first title for Flushing Meadows for 1999. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49604877 +sports Edinson Cavani: Manchester United set to sign former PSG striker Former Paris St-Germain striker Edinson Cavani go fly into England on Sunday to join Manchester United. Di Uruguay international, don dey follow United tok and although deal no dey ground for now, e dey look like say Cavani go join dem for wetin fit be two-year contract. Cavani no get contract again afta im comot Paris St-Germain for di end of June. E comot PSG afta di big kwanta im get wit Neymar and e feel say more European football still dey im body. United don put voice down say di player get desire to play for Old Trafford and if dem meet face to face, and that desire still dey, dem go give am deal. Man United also feel say Cavani age of 33 no be issue and say na im experience dem go use develop younger players for Ole Gunnar Solskjaer team. Im don score 341 goals in 556 club games. Including one wey be club record of 200 goals in 301 appearances for PSG. He has also score 50 goals in 116 internationals for Uruguay. If di deal go through, one of Cavani first games fit be against PSG, who be United opponents in dia first Champions League group game for di Parc de Princes on 20 October. https://www.bbc.com/pidgin/sport-54399697 +entertainment Laycon Big Brother Naija winner: Olamilekan Agbelesebioba N85 million BBNaija 2020 prize and why Lagos, Ogun tax office wan collect 7.5% VAT Lagos and Ogun States Internal Revenue Service don tok why dem ask di winner of di Big brother naija season 5 edition, laycon to pay tax out of di moni wey im win LIRS and OGIRS wey be di tax offices for inside di two neighbouring states for western Nigeria tok say tax law for Lagos and Ogun dey give pesin wey make income for di state one year to ready to pay 7.5 % value added tax to goment di next year. Big Brother Naija hand over di prize money and oda gifts wey follow am to Laycon on Wednesday morning. Big Brother Naija hand over di prize money and oda gifts wey follow am to Laycon on Wednesday morning. However tax authorities for Ogun state tell BBC Pidgin say if Laycon no dey live and work for di state, out of im good will im fit drop some moni for di state revenue as good citizen to support di state. Inside di 85 million Naira winning moni, Laycon suppose pay Value Added Tax (VAT) according to LIRS. VAT ontop dis money amount to 7.5 percent of di moni according to tax law for Nigeria. Tax law for Lagos and Ogun dey give pesin wey make income for di state one year to ready im total income and forward di tax to goment di next year. According to LIRS anybodi wey dey live, work or make money for Lagos state suppose to dey pay dia tax to di goment of di state. Di tins wey pesin suppose pay tax ontop include salary, business gains and even gifts and winning money for games plus odas according to LIRS. Dem say as Laycon don collect 85million Naira worth of prize e suppose come next year to declare how much e make in total and pay im tax from di moni. Apart from 85 million Naira moni wey Laycon win for BB Naija, im still win oda moni and gifts inside di house before di show end. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54352013 +sports Latest transfer news and rumour on Ronaldo, Foden, Vardy, Traore, Damsgaard, Ronaldo, Gomez, Angelino, Maddison England midfielder Phil Foden, 22, don agree a new long-term contract worth around £225,000-a-week for Manchester City. (Mail) Manchester United and Chelsea dey monitor Leicester City English striker Jamie Vardy, 35, wey get one year left on im current deal. (90min) Tottenham dey likely to turn to Wolves winger Adama Traore, 26, if dem dey unable to reach agreement with Roma for Italy midfielder Nicolo Zaniolo, 23. (90min) Brentford's £16.7m bid for Denmark midfielder Mikkel Damsgaard, 22, don dey accepted by Sampdoria. (Sky Sports) One club from Saudi Arabia Pro League don show say dia offer of a move for Manchester United and Portugal forward Cristiano Ronaldo, 37, go remain on di table afta di World Cup if im future no still clear. (CBS Sports) Manchester City don open talks with Anderlecht over Spain Under-21 left-back Sergio Gomez, 21, as alternative to Brighton target, Spaniard Marc Cucurella, 24. (Times - subscription required) Brighton dey consider RB Leipzig Spanish full-back Angelino as replacement for Cucurella, wey don also attract interest from Chelsea. (Sky Sports Germany, via Mail) Leicester don reject a second offer, wey worth just over £40m, from Newcastle for England midfielder James Maddison, 25. (Sky Sports) Eddie Howe side dey also target Leicester and England winger Harvey Barnes, 24. (Guardian) Leicester defender Wesley Fofana don hint of im at exit away from di King Power Stadium by removing Leicester City from im social media profiles. Chelsea don express interest in di 21-year-old Frenchman dis summer. (Leicester Mercury) Fulham don submit offer for Manchester United and Ivory Coast defender Eric Bailly, 28. (Football Insider) Chelsea dey interested in signing Southampton and England full-back Kyle Walker-Peters, 25. (Guardian) Everton no dey interested in re-signing English midfielder Ross Barkley, 28, or Belgium striker Michy Batshuayi, 28, despite say dem dey linked with di Chelsea pair. (iSport) Sevilla dey close in on a deal for Manchester United and Brazil left-back Alex Telles, 29. (Fabrizio Romano) Chelsea's French defender Malang Sarr go prefer a move to Monaco over Fulham, wey don target di 23-year-old. (Standard) Sheffield United don move in front of Brighton, Southampton and Leicester to sign Manchester City and England Under-21 midfielder James McAtee, 19. (Athletic - subscription required) https://www.bbc.com/pidgin/sport-62352265 +sports Ronaldo blame 'heat of di moment' as United drop am for game against Chelsea "Cristiano Ronaldo say ""di heat of di moment"" affect am for di incident wey lead to Manchester United dropping im for Saturday game at Chelsea. Di Portugal forward leave Old Trafford before di end of Wednesday 2-0 win ova Tottenham - where e for be substitute wey dem no use. ""I don always tre to set di example mysef for di youngsters wey grow in all di teams wey I don represent,"" e write on Instagram on Thursday. ""Dat no dey alway possible."" E add say: ""Sometimes di heat of di moment dey get di best of us. ""I just feel say I gatz to keep working hard for Carrington [United training ground], support my team-mates and dey ready for everything in any given game. ""Giving in to di pressure no be option. E no ever be. Dis na Manchester United, and united we must stand. Soon we go dey togeda again."" United say di 37-year-old remain one important part of di squad but regard dis as disciplinary mata. Di game e go miss for Stamford Bridge na big one, with United just one point behind fourth-placed Chelsea. Several media outlets dey report say e refuse to come on as a late sub against Spurs. Ronaldo leave di bench and walk down di tunnel for di 89th minute, even though United don only make three of dia permitted five substitutions. E briefly go inside di dressing room before leaving di stadium. Manager Erik ten Hag tok later say e go ""deal with"" di issue on Thursday. Ronaldo don also bin show say e no dey happy say dem substitute am during Sunday 0-0 home draw with Newcastle. Former England striker Gary Lineker tok say Ronaldo behaviour take di attention away from United good performance against Spurs. ""Dat dey unacceptable - e dey so poor,"" Lineker tok on BBC Match of di Day. Ex-Wales captain Ashley Williams say: ""Na great night for Manchester United and here we dey again toking about Cristiano Ronaldo - even though e no play."" Former England defender Micah Richards say: ""For one of di great of di game to do dat na wen your team dey win, making di mata about im, dey disappointing."" Richards tok say Ronaldo behaviour dey ""disrespectful"" and dem need to allow am to leave for di January transfer window. ""Im manager get problem with am for di start of di season, during pre-season, and to then carry dis on... I just think na only one way dis need to go now,"" Richards tell BBC Radio 4. ""Dem need to come to agreement for January and dem need to let am go. E dey undermine di manager there, so I think e dey best if dem just part ways."" Former United goalkeeper Peter Schmeichel tok say Ronaldo for know say such behaviour go create ""headlines"". ""Na di first time I fit say I dey disappointed with am. Normally I back am; I understand im situation,"" Schmeichel tell BBC Radio 5 Live. ""We dey for transition. Manchester United now na five managers down di road since Alex Ferguson. ""We have get Erik ten Hag in now wey get very clear ideas about di way e want to play football. ""We need understanding and time from everyone. ""We no need distractions like dat, and dat na disappointment, I go tok.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0vl9lywp3wo +politics Why di Niger State goment don ban okada pata pata, again No more motocycle riders for Niger state especially di capital, Minna. Dem tok dis one for statement wey di Commissioner of Information and Strategy, Alhaji Muhammad Sani Idriskanck signature on Wednesday as dem follow ban all illegal motor parks for di state. Unda dis new rules, wey dey for executive order, dem say offenders go smell pepper for dia hand: Dis no be di first time wey di state goment don ban motocycle aka okada. For April and June dis year, di goment bin cut warning give okada rider to comot for road. Dem say dem dey take dis action to address di security wahala wey dey knack akpako for di state. Attacks bin start dey rise since late 2017 and 2018 wen bandits begin dey disturb local communities for di north central state for Nigeria. Part of dia mode of operation according to di state goment and security agencies be say di bandits go dey us okada to attack communities and steal dia food items even animals like goats and cows. One of di biggest attack for di state na di 17 February kidnap of nearly 50 students from Government Science College for Kagara. According to one eye witness di jaguda pipo carry leg first enta di school and pack di students plus one teacher ontop motocycle enta bush. As e be so dem don free 23 of di students. Gunmen bin kidnap 136 students from Salihu Tanko Islamic school for Tegina town - many of dose wey dem kidnap na pikin. As di state bin dey battle di mata of insecurity, na so gist comot for April say Boko Haram raise flags for Kaure and Shiroro local goment areas of di state. To ensure say di safety of lives and property of citizens and reduce di tension among pipo say di bandits fit enta di capital, di state goment for April, set up a joint taskforce to enforce di ban of okada within dey capital. Di force include di Police, Nigeria Security and Civil Defense Corps (NSCDC), di Army and local vigilante groups. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59247619 +sports Transfer News: Which Premier League club buy beta market? Many pipo surprise wella for dis summer transfer window as clubs spend money, but which clubs get sense pass and which of dem buy beta market? You remember Moneyball - di feem wey Brad Pitt recruit baseball players from Oakland A based on Informate wey im get? Well, one London-based investment company Carteret Analytics feel say dem get one formula for footballers, wey dey dia system to take advise three Premier League clubs on new players dem fit sign. According to dia finding from dis transfer market, Arsenal fit don pay too much money for Nicolas Pepe, Everton suppose get more from Idrissa Gueye and one newly promoted team get one of di best deals of di window. Carteret Analytics use dia system to advise seven clubs for England top two league dem and 12 big clubs from Europe and di rest of di world too. Di data based on player value - dem go calculate fee based on dia performance for di club wey dey sell dem and di impact dem go get from di club wey dey buy dem plus dia age wey dey within (usually 26-30). Also, di value as per money aspect wey di player dey contribute to win football match and di kain influence wey im get to create and stop goal-scoring opportunity dem. By di time dem check dis value, clubs go make up dia mind to know how much dem want collect for di player head and how much too dem dey ready to spend ontop new player dem wey dem wan buy. Arsenal bin dey hot seat for transfer deadline day- dem sell Alex Iwobi to Everton and bring in Chelsea defender David Luiz and Celtic full- back Kieran Tierney. But how come dem dey for di bad business side. Iwobi real value wen im bin dey Arsenal rise up to £46.26m but dem sell am for just £27.36m, wey suggest say dem undervalue am by almost £19m. Arsenal sign Ivory Coast winger Nicolas Pepe from Lille for club record fee of £72m- £21.77m pass im real value figure. And dem buy teenage defender William Saliba cheap from Saint-Etienne and let dia former captain Laurent Koscielny go to Bourdeaux for more dan £20m under im projected fee. But Arsenal bring in replacement for Koscielny for good value. Dem rate Chelsea Luiz for £34.8m but Unai Emery team bring am in for £7.8m - no be bad deal for pesin wey don win Premier League and Champions League with plenty years of experience for England. Even though Crystal Palace sell dia best young player, dem do beta business for di transfer window according to Carteret Analytics data. And dem keep dia main player Wilfried Zaha, Palace buy Swansea striker Jordan Ayew for just £2.5m - wey less dan im intrinsic value. Dey also collect beta money for defender Aaron Wan-Bissaka, although im value fit rise for future for Manchester United. Dem sell Wan-Bissaka for £49.5m, im intrinsic value for Palace na just £23.32m. But dem expect di value to rise £43m for United but it still dey short of di money dem pay for am. Everton surprise pipo with di signing of 19-year-old forward Moise Kean from Italian champions Juventus. And di deal no bad, dem pay just £4m ontop im projected value. Dem also sign Manchester City Fabian Delph for under £9m.Dem bin value di England international for £54.58m to im selling club. Andre Gomes' permanent move from Barcelona cost just £22.5m too, a fee wey low pass im intrinsic value to Everton. And of course, di signing of Arsenal Iwobi na anoda good business. But Everton no shine eye wen dem sell. Midfielder Idrissa Gueye move to Paris St-Germain fall short of im £26m intrinsic value. Di best business happun for clubs wey dey outside di Premier League top six. Wolves smart for dia business for transfer market, dem sign loan players on permanent deals. Benfica sign Mexico striker Raul Jimenez, wey score 15 goals for 37 games last season for club record of £34m- na good deal because im intrinsic value na £43.37m. Dem also pay less for Belgian midfielder Leander Dendoncker wey value reach £16.13m afta im join dem on permanent deal from Anderlecht. Oda clubs wey do beta business for transfer market na Bournemouth, dem buy Huddersfield midfielder Philip Billing for £15m - half of im projected value fee and dem sell defender Tyrone Mings to Aston Villa more than im rating. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49333222 +sports Novac Djokovic: Australia cancel tennis No1 player visa and wan deport am "Australia goment dramatically cancel tennis star Novak Djokovic visa to enta dia kontri afta e arrive Melbourne airport. Border forces keep di world number one for airport for several hours before dem announce say im no meet entry rules and dem go deport am. Tori be say dem don cari am go goment detention hotel pending di time of im flight to leave Australia. Dis development dey happun as pipo dey para afta Djokovic say im get vaccine exemption to play di Australian Open. Djokovic neva tok about im vaccination status, but last year im say im dey ""opposed to vaccination"". Tennis Australia confam say dem grant one medical exemption for di player ""following ogbonge review process wey involve two separate independent panels"" but problems begin wen Djokovic land Melbourne late on Wednesday from Dubai. Inside statement, di Australian Border Force say Djokovic ""fail to provide correct evidence to meet di entry requirements to Australia, and dem don cancel im visa. ""Dem go detain and remove from Australia, pipo wey no be citizens wey no hold valid visa wen dem wan enta or wey dem don cancel dia visa,"" e add. Victoria acting sports minister tweet say di state no gree support im visa application inside all di confusion. Australia Prime Minister Scott Morrison deny say dem no dey target Djokovic and say no-one dey above di kontri rules. For press conference on Thursday, Oga Morrison say dem advice am say medical exemption no dey in place for di player entry and say di evidence wey dem provide dem ""find am to not dey enough"". Local tori pipo dey suggest say Djokovic fit pursue legal appeal or apply for new visa so im go fit re-enta and play for di tournament. Tori pipo Reuters report say dem later cari am from airport go one hotel wey dem dey use for immigration detention. Dis hotel be di place wia Covid-19 begin spread and recently fire burn di place, according to local tori pipo. Australia Health Minister Greg Hunt earlier describe Djokovic treatment as ""tough"" but ""fair"" and say ""na one rule for all under dis Australian goment"". But di way dem treat di tennis star provoke im kontri pipo for Serbia. Im papa, Srdjan Djokovic, say dem dey hold im son for one room wey police dey guard for di airport. ""Dis fight no be just fight for Novak, but fight for di whole world,"" im tok for statement. President Aleksander Vucic say di star na victim of ""harassment"" and say ""di whole of Serbia"" dey support am. Australia dey see tens of thousands of Covid-19 cases for di first time afta dem endure some of di world strictest restrictions. More dan 90% of Australia over-16 population dey fully vaccinated, but some pipo still no fit travel from one state to anoda or outside di kontri becos of current measures. Many Australians bin don accuse di goment of allowing di rich and famous to do as dem like while dem separate ordinary pipo from dia sick and dying loved ones. Di Australian Open go begin on 17 January for Melbourne. Djokovic don previously win di tournament nine times. ""Rules na rules,"" di PM tok, about Novak Djokovic deportation." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59891788 +politics Who dey Tinubu - Shettima APC Women Presidential Campaign team list "Nigeria ruling party di All Progressives Congress, APC on Saturday release dia list of those wey dey dia Women Presidential Campaign Team for di 2023 elections. Campaign for di 2023 general election for Nigeria don officially begin afta di Independent National Electoral Commission (Inec) fix 28 September, 2022 as date for campaign to start ahead of di February election. Di team go work togeda for di success of di party for di presidential polls. Dis women list dey come afta di party initially release a general list of di Presidential campaign council nominees. Just like di first list - Di APC Presidential Council nominees list wey see di absence of Vice-President Yemi Osinbajo, di women list also see di absence of im wife, Dolapo Osinbajo. First lady, Aisha Buhari meanwhile na di Grand Patron of di Tinubu/Shettima 2023 Women Presidential Campaign Team. Di total number of pipo wey make di list na 944 pipo. Di women campaign team dey made up of di Grand Patron wey be Aisha Buhari, Chairman na Senator Oluremi Tinubu, Co-Chairman na Hajiya Nana Shettima. Di team also dey made up of coordinators, advisory council and different committees. Oda ogbonge pipo wey take up positions dia na govnor wives, minister wives, politicians and oda ogbonge pipo from different works of life from entertainment to di media. Some of di names for di list especially for di entertainment committee don dey generate conversations. Notable names among di Creative and Entertainment industry committee na Nollywood actor Joke Silva wey dey be di chairman, Mercy Johnson Okojie and Yoruba actors Fathia Balogun, Madam Saje, Sola Kosoko among odas. While under di Media and Strategic Committee, names like Abike Dabiri, Lauretta Onochie and Morayo Afolabi Brown stand out. Campaign na di period wen politicians dey tell di pipo wetin dem go do wen dem enta power. Oga Christian Njigwum for interview wit BBC Pidgin say campaign council dey carry big responsibility. Though voting na everi body responsibility, campaigns dey target different groups and dem dey use different style and language for dem. E say wetin dey make members of campaign council dey plenty na sake of wetin di political party wan cover."" At di presidential level dem need to plan to cover all di 36 states of di federation and at di state level dem need to cover all dia local goment areas. ""Na those tins dey determine how di council dey be,"" di analyst tok. Di aim na to target voters wey fit give di political party and di candidates votes dem need to win election. Njigwum also say campaign councils dey also give chance to non-politicians to involve sake of policy documents. E say, ""di truth be say campaign council dey play important role for election period becos political parties and dia members no fit handle am alone. Dis na why dem dey get different committees wey dey handle different tins.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2j4j4pdne3o +entertainment Kim Kardashian: Kris Jenner tok about Kanye West and Kim Kardashian 'marriage crash' "Kris Jenner don finally break di suspense of wetin dey happun for di Kardashian-West family since Kim bin file for divorce last month. For interview wey she do for di Kyle & Jackie O show, she reveal say ""Kim dey deal with am privately with her own family"". She bin add say wetin she dey wish for na say di kids go dey happy. Dis go be di first time members of di Kardashian clan dey acknowledge di divorce in any way. However, Kris reveal say e go possible say e go fit dey as part of di plot for di final season of 'Keeping Up With The Kardashian' wey dey start dis month. Dis na as she say, ""e fit dey possible, but we neva see even di first episode of di show, to see how dem edit am, so e go dey hard to say."" Tori bin comot for February say Kim Kardashian bin file for divorce with Kanye West afta six years of marriage and six pikin. Well, Kanye West don comt enta small controversy on top how much money im get. Receently, deal wey im do with im Yeezy Brand with di Gap bin project say for future. Forbes recently comot to refute reports say Kanye West be di richest man for America as reports dey tok as dem say di 6.6 billion wey tori pipo bin dey carry up and down dey based on wetin di analysis show shey di partnership fit make for future. Dem tok say for now, Kanye West net worth na $1.8 billion from im net worth for last month wey make am join di billionaires club - $1.3 billion." https://www.bbc.com/pidgin/56448810 +politics Kogi Governorship Election 2019: Natasha Akpoti say dis one no be election again na war dey happun "Producers: Dooshima Abu, Gift Ufuoma Di only woman candidate for di Kogi State Governorship election ,Natasha Akpoti say she dey fear for her life. Since Natasha Akpoti chop beating for meeting venue wia di head of Nigeria Police and Chairman of di kontri election office - INEC attend,dem neva arrest anidodi. Madam Akpoti wey be di candidate of di Social Democratic Party( SDP) for di 16 November vote tell BBC Pidgin dis one days afta some jaguda boys burn down her secretariat plus beat beat and harass her wen she try one enta one stakeholder meeting wey INEC organise for di state. ""As I wan enta di venue of di meeting, dey guys come di harass me dey call me Ashawo, even come dey beat beat me and fall me for ground twice for di presence of security pipo and nobody say anitin"". Di 40 year old woman bin no fit hold back her emotion as she explain to BBC pidgin crew how she face humiliation for di jaguda boy dem hand. ""As I fall for ground di second time, my leg no fit cari me up even tho for my mind I wan stand up"" ""My pipo come cari me and as I dey waka dey go, e be like say na criminal I be"". ""Di boys still follow me come near my car break one of my drivers head"" she lament. Di governorship election for Kogi state na dis Saturday and so far di political temperature for di state don rise. Political parties and dia candidate dey do dia last minute campaign to woo electorate to come vote for dem But Natasha say di whole tin be like na war zone and dat because of di tention, e good make INEC shift di election so as to reduce di tension. ""Dis one no be election again na war we dey inside right now"" ""If you want comot, you must enta bullet proof cars, you go get mani back up and your heart go di beat because of di level of violence"" Natacha Akpoti claim say she don get threat say dem go either kill or kidnap her but she say no be today pipo dey die on top politics for Nigeria and she no go back down because of di threat. ""On Wednesday we hear gunshot for di back of my house and I tell my security pipo make dem also ready so dat dem go know say we no dey just empty"" ""I don report di mata for di DPO for my area and di DSS and dem don come put more security for my house area"" "" Even if I die today n aim be dat but di good tin be say e good make pesin die for one purpose"" she tok Meanwhile di commissioner of police for di state, Hakeem Busari say dem don launch investigation into di mata and dem go make sure say those wey do her dis strong tin go face di law. E also say di police don give her security pipo to protect her from any harm. Di current Govnor Yahaya Bello of Nigeria ruling APC, togeda wit Nigeria main opposition PDP candidate Wada go all 'put leg inside di same trouser' wit Natacha Akpoti of SDP dunring Saturday. Madam Apkoti for Okehi Local Goment Area inside Kogi North Central. Di winner of Saturday election na im go rule di state for anoda four years." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50416058 +sports Afcon 2021 go dey postponed? Caf president Patrice Motsepe assure say tournament go hold "Di president of Confederation of African Football (Caf), Patrice Motsepe don arrive for Cameroon as he dey determine to ensure say di Africa Cup of Nations dey successful. Rumour bin spread say di tournament wey dey scheduled to hold for Cameroon from January 9 to February 6, 2022 go dey cancelled or delayed. Covid-19 bin don make Afcon dey delayed before and many pipo wan know if dis tournament go hold for di scheduled date, and dis na why Motsepe enta Cameroon for Afcon meeting. Di Afcon president meet with Cameroon authorities yesterday and dem go still meet today to discuss di preparation of di tournament. Before im meet with President Paul Biya of Cameroon, Motsepe tok say: ""We dey very sure of our commitment to make (di tournament) a success for Cameroon."" ""I go dey Cameroon on 7 January wit my wife and kids to witness dis incredible competition. ""We go host wit di pipo of Cameroon an exceptional tournament. E go be di most successful Afcon. We dey ready to show di world di best of African football and African hospitality. ""Dis tournament dey important for di pipo of Africa and I dey so proud and so excited wit di work wey we don do."" Last week, top clubs for Europe according to reports threaten say dem no go release their players for Afcon sake of say dem get concern over di tournament Covid-19 protocol. For one letter wey European Club Association write give Fifa, dem say dem no fit release players if di tournament go make dia players miss dia club matches. ECA also tok say dem dey aware say Caf never make medical and operational protocol for Afcon ready, and dis kind tin no fit allow European clubs release players. Later, Caf announce say supporters wey go attend di match next month gas provide proof of vaccination and dem go present negative Covid-19 result. Before Motsepe enter Cameroon for Afcon meeting, president of Cameroonian Football Federation (Fecafoot), Samuel Eto'o say Caf no go dey postponed after im meet with di country minister of sports and physical education, Mouelle Kombi. If di tournament start for January 9, 2022, about 40 premier league players fit miss several weeks of di season. Watford players Ismaila Sarr (Senegal), Peter Etebo, Emmanuel Dennis, William Troost-Ekong (all Nigeria), Adam Masina, Imran Louza (both Morocco) dey among dose wey dia club fit miss if dem make dia kontris final list for di tournament. Some oda players wey fit miss several weeks of di premier league na Arsenal players and dem include: Thomas Partey (Ghana), Pierre-Emerick Aubameyang (Gabon), Nicolas Pepe (Ivory Coast), and Mohamed Elneny (Egypt). Meanwhile Sarr and Etebo dey likely to miss out on di tournament becos of injury." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59738002 +entertainment South Africa in shock over death of DJ Sumbody "Music Producer and Amapiano pioneer, DJ Sumbody don die, management Sumsounds music confam am. Di family tok-tok pesin Mmanake Mokitimi release one press statement to confam di report say investigation still dey go on to confam di cause of DJ Sumbody death. Local tori pipo for South eNCA also announce am as breaking news for dia early morning show ‘The South African morning' ""Dem kill di music producer and Amapiano pioneer in di early hours of di morning for Johannesburg. “Unconfam reports say dem shoot and kill di DJ .”, eNCA announce am. But im management say dem no fit give details of im untimely death but tok say di artiste bin run into an unfortunate incident wey lead to im death. Im family say di details wey surround im death no dey clear. At about 5am on Sunday, im bin recently post a video of imsef dey dance for club for im recent Instagram story. E no dey clear whether na di same day im record di video. But from oda recent post, di music producer suppose perform for one All White Veuve Clicquot Picnic on Sunday. One of im friends and colleague also confam di death for Twitter post wia im share fotos of dem togeda DJ Sumbody wey im real name na Oupa John Sefoka, na popular South African Disk Jockey and music artist. Im enta limelight afta e drop  hit songs like Ayepyep and Monate Mpolaye. Na im still be di brain behind di hit single Suk’emabhozeni wey make waves for di South African music industry. He don also collaborate wit oda artistes from across Africa. Im bin recently perform for one live concert of Nigerian artiste DBanj wey hold for Pretoria, South Africa. Im death na big blow to fans as dem don enta social media to express dia sadness and shock." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cl4g7x61j1xo +politics Muhammadu Buhari: Fr Ejike Mbaka ask President of Nigeria to resign, how Nigerians react "Rev. Fr Ejike Mbaka latest prophesy dey make Nigerians for social media dey react. Di controversial Catholic priest na ogbonge supporter of Nigeria President Muhammadu Buhari before before. But Fr. Mbaka make u-turn for im latest prophesy wia di priest say God ask am to withdraw im support for di president. Many Nigerians dey tok dia minds ontop di prophesy and dem dey divided into two main groups; Di ones wey want make dem protect Mbaka plus believe say im make sense die. And thse wey believe say di and spiritual director of Adoration Ministry no try at all. E still get some pipo for social media wey drag oda pastors wey don dey do prophesy say Buhari na di ansa wey Nigeria give. Rev. Fr. Ejike Mbaka criticize di leadership style of Nigeria president, Muhammadu Buhari on how im don handle insecurity for di kontri. Father Mbaka for recent video say ""God ask am to withdraw im support and prophesy against di President."" Im ask di 78 year old Nigerian leader ""to resign or make lawmakers impeach am"". Di Spiritual Director of Adoration Ministry say ""even though im don support President Buhari before e no mean say e go keep quiet sake of di many katakata wey dey happun for Nigeria."" Meanwhile foreign kontris like US, Canada, Australia and UK don advice dia citizens of di danger wey dey for some places in Nigeria. Dis security alert plus travel advice na as di West African kontri don begin record high level of crime and insecurity." https://www.bbc.com/pidgin/56933995 +sports Why dem postpone Man United vs Liverpool Match? "Manchester United don postpone dia Premier League match against Liverpool till further notice. Manchester United for inside statement, tok say di postponement of di match, wey suppose happun on Sunday for Old Trafford , na because of of ""safety and security concerns"". Dis dey come as di fans of di Red Devils bin break enta into di stadium to call for di sale of di club. Di fans no want di American family, Glazer Family to own di team again on top dia involvement for di failed European Super League mata. Premier League bin also announce for statement, say dem understand di feeling wey di fans bin dey take protest but dem no agree with di gra-gra way fans for di stadium take do am. Manchester United be one of di 'big six' wey initially join di European super league before dem comot hand say dem no do again afta backlash from fans. Dis current protest na because of Manchester United involvement for inside di doomed ESL however di tension no start now. But e get plenti reasons why dem dey protest, one fan say na di gbese wey Old Trafford don get dey make dem dey protest. Anda tin be say dem dey para say di club owners no dey gree to attend dia meetings. Already club supporters bin din dey beef di Glazer Family since dem take ownership of di club for 2005. However for dis ESL mata, di Manchester United Supporters Trust (MUST) don tok say dem no get any single trust for di owners on top say dem no care about di club an just dey for profit." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56964876 +entertainment Majek Fashek: How di Nigeria reggae legend take die at di age of 57 "Nigeria reggae music legend Majekodunmi Fasheke alias Majek Fashek don die according to e manager Omenka Uzoma wey confam e death to BBC Pidgin. Uzoma say 57-year-old Majek Fashek die for e sleep for New York on June 1, 2020. Di reggae music singer wey become popular sake of songs wey e sing like Send down di rain also work wit stars like Jimmy Cliff, Tracy Chapman and Snoop Dogg. Inside Instagram video wey Uzoma bin post, e say: ""dis na time for us all to celebrate e achievement, e don do a lot for Nigeria and Africa."" E also tell BBC Pidgin say Majek go like make Nigerians and world pipo remember am ""for good, for African inspiration, for e legacy and achievement"". Uzoma add say e go good make Nigeria goment recognize di efforts of Majek Fashek and e music as national day celebration on 7th of March wey be di day dem born Majek Fashek. Born in 1963 according to Uzoma, Majek Fashek come from Edo state, south south Nigeria. Im get four children from di union between him and Rita but di two of dem later divorce. For sometime now, di so long too long singer bin don dey battle wit health conditions wey according to Uzoma, ""threaten e life last year wen dem carry am go hospital for England."" Before today, di singer bin don release studio albums including Prisoner of Conscience , Spirit of Love, Rainmaker, Weep not my Children and Little Patience." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52888417 +sports Wayne Rooney: Derby County don appoint former England striker as boss "Championship side Derby County don appoint England record goalscorer Wayne Rooney as their new manager on two-and-a-half-year contract. Di 35-year-old, wey don dey in interim charge since dem sack Philip Cocu on 14 November, don also officially retire as player. Rooney don oversee nine games so far, e win three and draw four. ""Di opportunity to follow Brian Clough, Jim Smith, Frank Lampard and Phillip Cocu is an honour,"" he said. ""Inside me, I know say Derby County na di place for me."" Liam Rosenior go take up di role of assistant manager, with former England boss Steve McClaren go continue as technical director and advisor to di board of directors. Derby County dey third from bottom for di Championship, level on points with fourth-from-bottom Sheffield Wednesday. Di club dey expect new owners to takeover di club dis week, as current owner Mel Morris and Deventio Holdings Group bin don agree for di sale for November. Rams chief executive Stephen Pearce tok for interview with BBC Radio Derby on Thursday say problems no dey with di takeover, despite di delays meaning dem never pay players their December wages." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55680116 +sports CHAN Cameroon 2020: COVID-19 rules, tickets, security, and everytin you need to know Africa go gada for Cameroon in some days for de big football jamboree for home-based African players. Local organising committee say deh ready, di put final touch for opening ceremony for January 16. Cameroon di host first big competition for Africa since de outbreak of Covid -19, everytin you need for know about dis football feast. CHAN, African National Football Championship, na competition weh e di happen every two years for shine light for players from championships for Africa. Na 16 teams di take part for dis competition weh e start for 2009. Cameroon di host sixth edition. Because of COVID-19 Caf shift de football show from 4-25 April to January 16-February 7. As de first big football festival since Covid -19 start, Cameroon goment and Caf don agree for put strong rules for guide de championship. According to de tournament manager, Michael Disake, checking di start right from airport. Wen any delegation arrive deh test dem for airport. Caf and FIFA don put new rules for prevent COVID-19. For hotels, only one player for room, not two players for laik before. Instead of 23 players Caf add 10 players for waiting list for replace any player weh e catch Corona. Afta every 48 hours deh go test teams before deh go play. For stadiums na only 25 percent of dia capacities for de group stage and if supporters behave well, no invade field, no komot masks inside stadium, den keep social distance , CAf go fit increase de stadium attendance to 50 percent for semi final and finals. Covid-19 di stress Cameroon financially, especially as goment make budget before de outbreak. Before 2018, winner bi get $700, 000, (Fcfa 404 million). But, CAF increase de prize to $1.25 million dollars , (fcfa 674 million). De runner-up get $700,000, (fcfa 377million) , 3rd place $400,000 (fcfa 215 million) and fourth place $300,000 (fcfa 161 million). Morocco na current champions de lift de trophy for 2018. Dr Congo na first winner for 2009, Tunisia win de second edition, Libya for 2014, Dr Congo again for 2016. Na three host cities, wit four stadiums. Yaoundé host city wit 40,000 seats Amadou Ahidjo stadium for Group A, Douala wit 40,000 Bepanda stadium and Doula, second pool wit de new 50,000 seater Japoma stadium. Limbe/Buea for Southwest Cameroon wit de Omnisport 20,000 seater stadium. Group A: Cameroon, Mali, Burkina Faso, Zimbabwe/ Yaoundé Group B: Libya, Niger, DR Congo, Congo/Douala Group C: Morocco, Rwanda, Togo, Uganda/Douala Group D: Zambia, Guinea, Namibia, Tanzania/Limbe Na first come first serve for fill de 25 percent quota. Ticket go on sale fir January 11 and for match days deh go close gates. Tickets cost from fcfa 1000 to fcfa 50,000. De first sales points na total filling stations, kiosk for stadiums, ministry of sports for Yaoundé and regional delegations of youth and sports and odas. Separatists groups don threat say deh no wan any football for dia territory. Some groups claim say deh don notify teams. Dis threats komot for de same taim weh three attacks happen for Northwest region and kidnappings for Southwest region. Tournament coordinator say deh di read about de threats, but say na work for security. For meeting weh defense minister hold some days ago, deh decide for put high security for around hotels, transport and training grounds. Fans zones go bi for all host cities, For Yaoundé, na for Town Hall. Since all man no fit enta stadium, deh go put large screens for dis fan zones. Kontri pipo go fit buy chop and soft drink as deh di watch match. Visitors fit also buy gifts for dis places. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55614843 +sports Everton 2 - 1 Arsenal: Richarlison, Gray goals save Everton from Arsenal for EPL match Demarai Gray injury-time strike help Everton beat Arsenal during Monday night Engligh Premier League game. Richarlison 79 minute goal na im equalize Arsenal half time lead from Martin Odegaard goal for 47 minute. Video Assistant Referee disallow two goals from Everton Richarlison before im eventual equalizer and Gray winning goal. Di gunners bin dey try to recover from dia 3-2 loss to Manchester United on Thursday - dia second defeat in 13 games. But Everton wey dey without dia striker, Dominic Calvert-Lewin dey also hope to return to winning ways. Though last season di Toffees win di two legs wen dem meet Arsenal, e no clear if na so e go be dis season. Everton defender Yerry Mina don recover from injury and e fit play im first match for di first time since 2 October. Salomon Rondon still need to do scan on im hamstring injury, while Mason Holgate go dey available afta im suspension. Granit Xhaka and Sead Kolasinac neva still fit fully. But Arsenal midfielder Bukayo Saka fit return to di starting line-up afta e come as substitute against Manchester United sake of a minor injury. Di match go also be some kain supremacy battle between Arsenal goal keeper Aaron Ramsdale and Jordan Pickford of Everton on who suppose be England number one keeper. Everton no dey impressive for some time. Mark Lawrenson, BBC Football expert say Everton don get only two points from dia last eight games. Dem also manage to score only five goals in di process, Lawrenson wey pipo know as Lawro tok. Lawro believe Arsenal, despite dia loss to Manchester united for dia last match get better chance to win di match. Prediction: 1-2 https://www.bbc.com/pidgin/sport-59545363 +entertainment BBNaija: Kiddwaya, Tolanibaj na new head of house and deputy for Big Brother lockdown season 5 Terseer Waya, aka Kiddwaya don become di new head of house of Big Brother season 5 afta im win di HoH Challenge dis evening. As Head of House, Kiddwaya don get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week. Im also get di power to pick any housemates as in deputy to follow am jolly immunity and di lounge, E don nominate Tolanibaj as im deputy for di house. she go follow enjoy access for Head of House lounge and inmmunity for eviction.. Im go be di second male housemate wey go be HoH afta Ozo wey rule di house week before last. Dis one go make am two weeks back-to-back im don get immunity for di house as e be deputy HoH last week under Erica. Big Brother add more jolly for di mata as im announce say both Head of House and im deputy go fit select one housemate each wey go follow dem jollificate for di Head of House Lounge, only thing be say dis two housemates no go fit sleep for dia. As e be now, na 13 housemates dey on di line for possible eviction. https://www.bbc.com/pidgin/media-53810157 +entertainment Peter Okoye: Mr P open up about im solo career since im break up wit Psquare "Nigeria singer and former member of Psquare, Peter Okoye don open up about im solo career. Peter wey im stage name now na Mr P tok to tori pipo HipTV about how tins be for am since im leave Psquare and go solo. Dis na tins wey Mr P reveal about im solo career. For di interview Mr P say im dey make more money as a solo artist. ""Hundred percent, I no dey share three ways. Call am greed or selfishness. Na you own cup of tea. I no dey share wit anybody. Yes, my management and my team. Fine. But I dey do my own thing. Mr P also tok about freedom as a solo artist. "" Freedom dey key. I fit get call about a show next week and na my daughter birthday. I fit say, 'cancel am'. As a group, I no fit do that. Moneywise, I bin dey used to share three ways, I dey share alone,"" na so im add put. Na 2003 di top Nigerian musicians wey be identical twins, Peter and Paul Okoye start dia music career wit different bangers and plenti awards. But for September 2017, reports bin drop say di duo don go dia separate ways sake of family kwanta." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56863689 +sports 'I be one of de Black Stars' - Striker Inaki Williams switch nationality from Spain to Ghana Top Atletico Bilbao striker, Inaki Williams announce en decision to represent Ghana. He make de announcement on en Twitter page today after months of speculation which dey link de player to Ghana ahead of de 2022 Fifa World Cup. “De moment come for me to find my origin within myself with Africa den Ghana” Inaki talk inside video. “I want return small part of everything sake of Ghana play significant role in becoming who I as a person” he add. He conclude by saying “today new challenge dey begin. From now on I go defend Ghana T-shirt with my all. I go give my best, I be one of de Black Stars.” Black Stars announce say de top striker go be part of de Black Stars squad. Inside post for social media, dem write “welcome to de Black Stars, Inaki Williams.” De decision of Inaki Williams be major surprise as pundits no expect say he go switch nationality Spain to Ghana. Inaki Williams be professional footballer who dey play for Atletico Bilbao in de La Liga. Born to Ghanaian parents, wey enter Spain by crossing de Sahara desert on foot and jumping over de Melilla border fence, Williams spend most of en childhood developing en football talent. At de age of 18, Atletico Bilbao spot him wey dem sign him to dia youth team. He make en first team debut in de La Liga in 2014 for Atletico Madrid, get en first goal de following year February. Years later, de young talent establish himself as key player in de senior side leading Atletico to major wins including 20 meter goal against Barcelona in de Spanish Super Cup final. International career He get en first international call up to represent Spain under-21 squad in March 2015. Despite playing for Spain junior national team, he no make major competitive appearances in dia national team side. In 2021 when dem ask am about de possibility of playing for Ghana he talk say “my parents dey come from Accra, dem no born or raise me there, my culture dey here.” But on July 5, 2022 he make u-turn on en decision to represent Ghana by wearing de Black Stars ahead of de 2022 Fifa World Cup. Ghanaians for social media make excited over de decision of Inaki Williams to play for de Black Stars. Social media users dey share dia own views on how he go help Ghana in de World Cup. Black Stars captain, Andre Ayew welcome de striker to de national team side after de announcement. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn043lnv1p2o +entertainment Obi Cubana source of Income: Cubana Chief Priest oga Obinna Iyiegbu source of money Obi Cubana mother burial for Oba, Anambra State dey make many ask of im source of Income. Di funeral of Lady Uche Iyiegbu, di mama of Obinna Iyiegbu wey everybody know as Obi Cubana for Anambra state South east Nigeria generate buzz for internet over di past few days. Di plenty reaction no be sake of Late Iyiegbu popularity but na how im son Obi Cubana attract attention to Oba, a small village for Idemili South Local goment area of Anambra state. Tori be say na for December 2020 Obi Cubana mama die at di age of 75 years. But from di outcome of di burial e show sey im take time plan am well as im friends and associates send am several gifts as support for di burial of late Ezinne. Multiple award winning artist, Davido, Phyno, D'banj, Kanayo O. Kanayo, E-money, Shina Peller, Ubi Franklin, Cubana Chief Priest, Kcee, Odumeje na some of di celebrities wey attend di burial. No doubt im go get oda businesses but Obi Cubana na mogul for hospitality industry, show business and entertainment for Nigeria. Im na di chairman and owner of popular Cabana groups. Im get chain of fun places including hotels, clubs for lounge for different cities for Nigeria, Abuja, Lagos, Enugu, Port Harcourt, Owerri wit plan to expand go abroad. Obi Cubana networth dey around $96million but dis dey yet to be verified. Obi Cubana wey im real name na Obinna Iyiegbu na 46-year old man from Idemili South, Anambra state - dem born am for April 12, 1975. Im go secondary school for Onitsha and later attend University of Nigeria Nsuka wia im earn Bachelor of Arts for Political Science for 1998. Obi Cubana marry im wife for 2008 and im get four children. Celebrity barman, Cubana Chief Priest real name na Pascal Chibuike Okechukwu. Im na business man wey get big investment for entertainment and showbiz - na im get Club Xhrine for Owerri, Imo state. Dem born Cubana Chief Priest for April 2, 1981 for Umuhu Okabia, Orsu Local Government Area of Imo state. Na im be di second son of im parents wey train am for Aba, Abia state wia im learn shoemaking. Cubana Chief Priest later attend Federal Polytechnic Nekede Owerri, wia im earn im first degree. For early 2021 im bag degree as Doctorate of Science for Event and Luxury Hospitality Management from European American university - im announce di degree on im Instagram page on Saturday, April 24, 2021. Pascal Chibuike Okechukwu aka Cubana Chief Priest get wife and children. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57872724 +health Coronavirus: Ghana Health Service start dey investigate 3 health officials who 'dey sell Covid-19 vaccines' "Ghana Health Service begin investigations into how three health officials steal den sell Covid-19 vaccines. National Security arrest de three over allegations that dem steal vaccines den sell for profit, while de vaccines be free. Occupational Health and Safety Officer, Cosmos Allotey dey receive de stolen vaccines from one Pabitey wey another suspect, Dzisenu dey administer each shot of de vaccine to people for around $30 dollars. Director General of de Ghana Health Service (GHS), Patrick Kumah Aboagye addressing de press on de matter talk say dem start dey work plus National Security and de health institutions to uncover de theft case. ""We initiate some administrative procedure for de various leadership in those centre's to assist us plus report den also uncover other ones we no know about"" Mr Kumah Aboagye talk. According to GHS dem make ready to cooperate plus de security agencies to uncover de circumstances wey lead to de theft den tins." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56481793 +health Occupy Ghana: Group accuse govment of 'massaging' coronavirus death figures "Govment of Ghana shoot down claims say dem dey under report de actual number of people wey die after contracting Covid-19. Dis be after pressure group, OccupyGhana challenge govment say de difference between national death toll figures and regional data on deaths wey dem collect no dey match. ""We get reason to suspect say check like dem dey massage death numbers,"" Occupy Ghana explain. According to de pressure group, ""De 54 deaths wey dem report be someway. For instance, even though 38 people die for Ashanti Region alone, less than 20 of de deaths recorded dey feature inside de national count!"" For OccupyGhana, if de public suspect say under reporting dey happen dem go lose trust in de reporting system wey that go fit affect people dema behaviour to de virus. But Ghana Health Service (GHS) say dis accusation no be right. GHS Director-General, Dr. Patrick Kuma-Aboagye explain say ""nobody dey hoard numbers deliberately."" ""We know de situation reports dey… but process dey because we no sheda be interested in just de numbers, but also we dey validate and try know what we go do,"" he add. Ghana get one of de lowest Covid-19 death tolls for Africa, despite a total of 12,193 confirmed cases, 4326 people recover wey only 58 die as of yesterday." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53074873 +sports The Best Fifa Men's player awards: Ronaldo, Messi, Salah and Mane make Fifa Best awards nominees list Liverpool players Sadio Mane and Mohammed Salah don make di shortlist for di nominees for Best Fifa Footballl awards for 2020. Dis na di second time in di last two years wey di Egyptian and di Senegalese player go make di shortlist. FIFA also reveal di candidates shortlisted for seven of di individual trophies wey dem go present for The Best FIFA Football Awards™ ceremony on 17 December 2020. Two expert panels - one for women's football and one for men's football - na dem select di candidates for each category. Public voting dey open on FIFA.com and go run until 9 December 2020 (23:59 CET). FIFA go announce di three finalists for each of di seven categories on 11 December 2020. The Best FIFA Football Awards™ 2020 go take place on 17 December, 2020. Di nominees dey listed below in alphabetical order: •Thiago Alcântara (Spain / FC Bayern München / Liverpool FC) •Cristiano Ronaldo (Portugal / Juventus FC) •Kevin De Bruyne (Belgium / Manchester City FC) •Robert Lewandowski (Poland / FC Bayern München) •Sadio Mané (Senegal / Liverpool FC) •Kylian Mbappé (France / Paris Saint-Germain) •Lionel Messi (Argentina / FC Barcelona) •Neymar (Brazil / Paris Saint-Germain) •Sergio Ramos (Spain / Real Madrid CF) •Mohamed Salah (Egypt / Liverpool FC ) •Virgil van Dijk (Netherlands / Liverpool FC) •Lucy Bronze (England / Olympique Lyonnais / Manchester City WFC) •Delphine Cascarino (France / Olympique Lyonnais) •Caroline Graham Hansen (Norway / FC Barcelona) •Pernille Harder (Denmark / VfL Wolfsburg / Chelsea FC Women) •Jennifer Hermoso (Spain / FC Barcelona) •Ji So-yun (Korea Republic / Chelsea FC Women) •Sam Kerr (Australia / Chelsea FC Women) •Saki Kumagai (Japan / Olympique Lyonnais) •Dzsenifer Marozsán (Germany / Olympique Lyonnais) •Vivianne Miedema (Netherlands / Arsenal WFC) •Wendie Renard (France / Olympique Lyonnais) •Ann-Katrin Berger (Germany / Chelsea FC Women) •Sarah Bouhaddi (France / Olympique Lyonnais) •Christiane Endler (Chile / Paris Saint-Germain) •Hedvig Lindahl (Sweden / VfL Wolfsburg / Atlético de Madrid Femenino) •Alyssa Naeher (USA / Chicago Red Stars) •Ellie Roebuck (England / Manchester City WFC) •Alisson Becker (Brazil / Liverpool FC) •Thibaut Courtois (Belgium / Real Madrid CF) •Keylor Navas (Costa Rica / Paris Saint-Germain) •Manuel Neuer (Germany / FC Bayern München) •Jan Oblak (Slovenia / Atlético de Madrid) •Marc-André ter Stegen (Germany / FC Barcelona) •Lluís Cortés (Spain / FC Barcelona) •Rita Guarino (Italy / Juventus Women) •Emma Hayes (England / Chelsea FC Women) •Stephan Lerch (Germany / VfL Wolfsburg) •Hege Riise (Norway / LSK Kvinner) •Jean-Luc Vasseur (France / Olympique Lyonnais) •Sarina Wiegman (Netherlands / Dutch national team) •Marcelo Bielsa (Argentina / Leeds United FC) •Hans-Dieter Flick (Germany / FC Bayern München) •Jürgen Klopp (Germany / Liverpool FC) •Julen Lopetegui (Spain / Sevilla FC) •Zinedine Zidane (France / Real Madrid CF) Who go succeed 2019 winner Daniel Zsóri to take home di coveted crown dis year? Di eleven-goal shortlist for di best goal of di year also don dey revealed: •Shirley Cruz (CRC) - Costa Rica v. Panama [Concacaf Women's Olympic qualifying] (28 January 2020) •Giorgian De Arrascaeta (URU) - Ceará SC v. CR Flamengo [Brasileirão - Brazil] (25 August 2019) •Jordan Flores (ENG) - Shamrock Rovers FC v. Dundalk FC [League of Ireland] (28 February 2020) •André-Pierre Gignac (FRA) - UANL Tigres v. Pumas UNAM [Liga MX - Mexico] (1 March 2020) •Sophie Ingle (WAL) - Arsenal WFC v. Chelsea FC Women [FA Women's Super League - England] (19 January 2020) •Zlatko Junuzović (AUT) - SK Rapid Wien v. FC Red Bull Salzburg [Bundesliga - Austria] (24 June 2020) •Hlompho Kekana (RSA) - Mamelodi Sundowns FC v. Cape Town City FC [South African Premier Soccer League] (20 August 2019) •Son Heung-min (KOR) - Tottenham Hotspur FC v. Burnley FC [Premier League - England] (7 December 2019) •Leonel Quiñónez (ECU) - Universidad Católica v. CSD Macará [Serie A - Ecuador] (19 August 2019) •Luis Suárez (URU) - FC Barcelona v. RCD Mallorca [LaLiga - Spain] (7 December 2019) •Caroline Weir (SCO) - Manchester City WFC v. Manchester United WFC [FA Women's Super League - England] (7 September 2019) Dem go select di winner of di FIFA Puskás Award through international jury comprising a panel of FIFA Legends and by di fans from all over di world wey register on FIFA.com. Each of di two groups of voters within di jury get di same electoral weight. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55070386 +politics Peru and oda kontries wey get female president "On Wednesday Peru swear in Dina Boluarte as dia first female president. Madam Boluarte wey be former vice president take her oath of office afta di impeachment of ex- president  Pedro Castillo. Dem impeach Castillo afta im try to dissolve parliament. Earlier, Oga Castillo bin wan replace Congress wit ""exceptional emergency goment"". But lawmakers ignore am, na for emergency meeting dem impeach am. Dem detain am and accuse am of rebellion. Reports for local media say im bin dey go Mexico embassy for di capital wia im chop arrest. Na afta wetin happun to Oga Castillo, Madam Boluarte, wey be 60 years take become president of her kontri. She say she go govern until July 2026, dat na di time wey Oga Castillo presidency go end. She tok afta di oath of office, she call for political peace to overcome di wahala wey her kontri dey go through. ""Wetin I ask for na space, time to rescue di kontri,"" she tok. Madam Boluarte don join a list of women wey be president, we go torchlight dem for dis story. President Samia Suluhu Hassan na di current President of Tanzania. She become president for her kontri for March 2021 afta di death of President John Magufuli. Before then she act as vice president. Na for 2015 dem elect Madam Samia Suhulu Hassan as Oga Magufuli running mate and again for 2020. She dey expected to serve out di remainder of im five-year term. For October 2018, Parliament elect Sahle-Work Zewde as Ethiopia first female president. Madam  Sahle-Work, na experienced diplomat, wey promise to work to make gender equality a reality for her swearing-in for di largely ceremonial post. She bin take office a week afta Prime Minister Abiy Ahmed bin appoint im cabinet wey half di post go to women. Outgoing Governor-General Sandra Mason, na di last representative of British Crown. She become di first president of Barbados for November 2021. Parliament bin choose her di previous month. Even though dem don decide to become a republic for 2020, Barbados go still remain a member of di Commonwealth. She be di first woman to serve as judge for di Barbados Court of Appeals. Opposition candidate Zuzana Caputova beat di goment Maros Sefcovic for di second round of di March 2019 presidential election, wit 58% of di vote. She be lawyer and long-standing anti-corruption campaigner, she dey known for a decade-long fight against one poisonous landfill for her hometown of Pezinok.\nMadam Caputova bin dey moved to stand for president during protests ova di murder of one journalist Jan Kuciak, wey bin dey investigate links between politicians and organised crime wen dem bin shoot and kill am along wit im fiancée for February 2018. Tsai Ing-wen become Taiwan first female president wen dem elect her for  January 2016. Madam Tsai political message always dey around di importance of Taiwanese identity, and she promise say democracy go dey di heart of the island future relations wit China. Na 2015 dem elect Bidhya Devi Bhandari as Nepal first woman president for one parliamentary vote for October 2015. Before she become president she hold di position of deputy leader of di Maoist Communist Party of Nepal Unified Marxist-Leninist (CPN-UML) and she be former defence minister. She be campaigner for women rights and widow of late communist leader Madan Kumar Bhandari. Di post of president dey mainly ceremonial. Na Parliament elect Katerina Sakellaropoulou for January 2020, and then she enta office for March. She be Greece first female head of state. Before den, na she be di president of di Council of State, di kontri highest administrative court. Greece presidency dey largely ceremonial, as executive power dey for di hand of di prime minister. Salome Zourabichvili first become popular for 2004, wen President Mikheil Saakashvili appoint her as foreign minister. She bin previously serve as ambassador to France, wia dem born her, she be di daughter of Georgian emigres and she work for French diplomatic service, before she obtain Georgian citizenship. But she soon turn against di president, she accuse am of being a ""dictator"", although she remain independent of di Georgian Dream party wey defeat Oga Saakashvili for di 2012 elections. Georgian Dream don reduce di presidency to a ceremonial post, and all future presidents dey expected to dey selected by electoral college, not di public. Madam Zourabichvili bin for di post as an independent candidate for 2018, with di backing of Georgian Dream, she beat pro-Saakashvili opposition challenger Grigol Vashadze for di run-off. She dey due to serve a six-year term. For April 2021, parliament choose Speaker Vjosa Osmani as president to serve a five-year term. Dis follow di resignation of President Hashim Thaci for November 2020 on learning about Kosovo war crimes tribunal for Hague wey confirm im indictment for war crimes." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c72e5l8jl39o +sports Seven cool facts about Qatar 2022 Fifa World Cup Di 2022 Fifa men World Cup for Qatar na just 19 days away. 32 teams go compete for eight groups wey include five African teams. Di five African teams wey qualify na Ghana, Senegal, Cameroon, Morocco and Tunisia. Some big names go miss out on di tournament sake of injury. Defending champions France go dey without Ngolo Kante and Paul Pogba while Portugal go miss Diego Jota for di tournament. E get many tins wey make di Fifa World Cup for Qatar unique. Dis na some of di fun facts about di tournament wey pipo dey look forward to. Di World Cup bin dey usually hold for di middle of di year but wen Qatar get right to host, Fifa need to consider di weather. Sake of say e dey for Middle East, Qatar get high temperatures wey fit reach up to 50 degrees Celsius sometimes. E go make dis World cup one of di most expensive World Cups in di history of di game. Dis na di lowest number of venues for di World Cup in recent years -  Di last time any host kontri use six stadium for di world cup na for Argentina ’78. In fact, out of all di eight venues selected to host di tournament na only one dem renovate – di kontri build seven new stadium sake of di competition. To tackle di issue, Qatar come up wit an brave solution. For di first time ever, one kontri go host di Fifa World Cup inside fully air-conditioned stadiums. All di eight venues for Qatar go dey fully air-conditioned. First time Qatar dey play for World Cup: Dis na di first time Qatar go participate for di World Cup competition. Dia national team don attempt to several times but dem no dey qualify. Hosting di tournament give dem automatic chance to qualify for di World Cup. Di three female refs na; Salima Mukansanga, aged 33, Yoshimi Yamashita, aged 36, and Stephanie Frappart, aged 38. Dem follow for di 36 referees wey go manage di matches for di tournament. Di coaches na Walid Regragui (Morocco), Aliou Cissé (Senegal), Rigobert Song (Cameroon), Jalel Kadri (Tunisia), and Otto Addo (Ghana). Host cities like Doha, Lusail, Al Wakrah, and Al Rayyan dey close to each oda. Di two most remote stadiums of Qatar, Al Bayt and Al Wakrah na only 90 miles apart. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cevd1peg25ro +politics 'Take Rivers, give us presidency', how Peter Obi negotiate wit Wike "Di presidential candidate of Labour Party Peter Obi give assurance to di govnor of Rivers state, south of di kontri say im go tok to im supporters on how to vote during elections for di state. Peter Obi and im running mate Datti Baba-Ahmed bin go Port Harcourt, di Rivers state capital to commission di number nine flyover  wey di Govnor Nyesome Wike goment  build on Thursday. Obi during di commissioning of di new flyover project tell oga Wike say im don hear wetin e tok unto make e warn im supporters make dem dey careful about di state. Dis na dis second time wey Obi dey go Rivers state to commission project. “I don hear wetin you tok, make I advise Labour pipo to dey careful about di state. And I go tok to dem.” Afta im promise to tok to dem di Labour party presidential candidate say di mata na about negotiation. Peter Obi say if im party leave di govnorship election for Nyesom Wike, di Rivers state govnor go support Labour party for di presidential election go leave centre for dem. “Oga say, if we give dis side, we go also give dat side, if we leave state for am, im go leave centre for us,” im tell Wike. For im address, Wike welcome Obi to im state and promise am say anytime im wan come do campaign for Rivers state make e let am know and im go provide am wit di “necessary logistics and arrangement.” For im speech, di Rivers state govnor say im sabi di humiliation wey Obi suffer wey make am port from di Peoples Democratic Party (PDP) go Labour Party. “I know di humiliation wey you suffer. ""Nobody go hear wetin you pass through still say for di party. But me I no go leave. I go stay and fight,” Wike tok. Although Wike and im supporters be like dem no dey campaign for Atiku, e neva clear weda or not dem dey support Obi of di Labour Party abi Bola Ahmed Tinubu of di ruling All Progressive Congress for dia presidential ambition. Rivers state Govnor Nyesom Wike and im team don pull out of di Peoples Democratic Party PDP Presidential campaign council. Dis na becos dem dey insist say di current chairman of di party, Iyorchia Ayu must resign and give way for an acting chairman from southern Nigeria wey go lead di party to victory for di 2023 general elections. As dem rise from one meeting for Port Harcourt, di Rivers State capital for Spetember, members of di team vow not to take part for Atiku campaign activities if di National Chairman, Iyorchia Ayu no resign. Di team members include Governor of Oyo State, Seyi Makinde, former Governors of Cross River and Ekiti states Donald Duke and Ayo Fayose among many odas. E never too tey wen di PDP bring out list of names wey dey di PDP Presidential campaign council wey di governor of Akwa Ibom State, Udom Emmanuel na di Chairman while Bauchi State Governor, Bala Mohammed na di vice chairman for north and Oyo state give to, Seyi Makinde na di vice chairman for south and Governor Wike na member of di council." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp47rdvx90ro +entertainment Angel and Boma fight BBNaija S6: Big Brother Naija Housemates Boma rain insult on Angel "Big Brother Naija housemates Boma and Angel shake di house wit fight on Thursday evening. Sotey Angel comot wig, follow Boma like she wan beat am but oda housemates bin hold am. Dem two throw big insults at each other wit big abusive words wey dey fly upandan. Dis no be di first time wey Angel and Boma don cross each other lane. Angel say Boma dey manipulative and she no care if she dey disqualified but she no go take insults from am. Boma bin accuse di 21 year old say she tell Queen say im -Boma- na kiss and tell, na wetin make Angel para. Angel deny di accuse, say di tok dey come out of nowhere. ""He dey call us children, wen I tok dat one""- Angel tok Boma insult Angel family members and also tok say di platform na her biggest achievement. Angel later respond say Boma na 34-year-old wey dey on di sam platform wit her and she warn am make she no bully her for di house. She also warn am make im no bring her family members, into di conversation again and say im be fake okra- e no dey clear wetin she mean by dis though- in di spirit of insult. Angel accuse Boma say im dey look for highlights for di game." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58425981 +business UK-Africa Summit 2020: Deals wey Nigeria, Ghana sign for di London investment meeting British goment sign 27 commercial deals wey reach ova £6.5bn across Africa market afta di first ever UK-Africa Investment Summit for London. Tori be say dis summit na strategy for UK to become di biggest investors for Africa even though trade volumes between kontris like China and India for Africa don grow well-well. British goment bin don already sign 11 trade agreements wit African kontries, just a week before dem go officially waka comot from di European Union Di first ever investment meeting between UK and African kontris bin start on Monday January 20 and na UK Prime Minister, Boris Johnson na im go open di summit wey 21 African kontries attend. See di deals between UK companies and African partners here: https://www.bbc.com/pidgin/tori-51203355 +entertainment CNN Larry King: America television host Larry King [Lawrence Harvey Zeiger] die afta e catch Covid-19 Larry King, wey be Veteran broadcaster don die at di age of 87. Na for di official Twitter handle of di American Broadcaster na im news of [Larry King death drop] wey be TV, radio host don die King bin test positive for coronavirus for early January and dem acrri am go hospital inside Los Angeles,. Im bin dey receive treatment for Cedars-Sinai Medical Centre for over a week. King die on Saturday morning for Cedars-Sinai Medical Cente , Ora Media, im production company, confam inside statement. After e catch Covid-19, dem bin admit am into hospital for condition wey serious sotey dem place am [Larry King] on a ventilator. Larry King na ogbenge broadcaster wey be televison and radio host. Before im death Larry King bin work for CNN wey be American cable network for a long time. Larry King wey real name na [Lawrence Harvey Zeiger] bin live from November 19, 1933 until 23 January, 2021. https://www.bbc.com/pidgin/55781287 +health Nigeria National Health Authority Act - Five key facts President Muhammadu Buhari don approve a new law to pave way for major health coverage across Nigeria. National Health Insurance Authority Bill 2022 wey di Nigerian leader sign hope to improve access to medical services for all citizens. Dis new health care law aim to expand social health insurance to reach poor Nigerians without palava of financial hardship. 83 million poor Nigerians na im oga Buhari goment say di new health care law go benefit. BBC Pidgin highlight five tins wey dey important to know about dis health coverage policy. Di National Health Insurance Authority Bill 2022 don cancel di National Health Insurance Scheme Act, Cap N42, Laws of Nigeria 2004. President Buhari tok say im sign di bill sake of say im e dey part of im healthcare reforms. Di president say goment go ensure di full implementation of di new Act to provide coverage for all Nigerians. Na 83 million pipo di bill dey target to benefit, according to President Buhari tok-tok pesin Garba Shehu. Dis number of pipo na poor Nigerians wey no fit afford to pay health insurance premiums. Di goment plan to set up a Vulnerable Group Fund wey go include a part of di Basic Health Care Provision Fund due to di authority. Dem go also raise money through Health Insurance Levy, Special Intervention Fund. In addition dem plan to fund wit any investment returns, donations and gifts to di authority. Nigerians goment say di National Health Authority go join bodi wit state goment health insurance schemes. Di partnership na to accredit primary and secondary health facilities and enroll Nigerians into di scheme. Di federal goment say dis partnership dey important to ensure di quality of health care. Di new law go enable authority and goment to develop information management system and digital records. Dis go ensure say dem collect data effectively, and monitoring and quality assurance go also dey assured. President Buhari ask di Health Reform Committee to work wit state goments, di Federal Ministry of Health. And dem gatz work wit di National Health Insurance Authority to ensure di implementation of di articles in di new Act. https://www.bbc.com/pidgin/tori-61528393 +sports Australian Open: Roger Federer go miss di 2021 tournament "Six-time champion Roger Federer go miss tdi Australian Open for di first time for im career as he continues to recovery from knee surgery. Di 39-year-old Swiss, wey be 20-time Grand Slam winner, neva play once since January because of two operations. He hope to return at di delayed Australian Open, wey go start on 8 February for Melbourne. ""Roger bin run out of time to get imself ready for di work of a Grand Slam,"" di tournament director Craig Tiley tok. Federer don play for di Australian Open 21 years back to back, but im agent say missing di tournament na ""the best decision for am in di long run"". Federer most recent last competitive match na di semi-final defeat by eventual champion Novak Djokovic for dis year Australian Open. For February, Federer bin do arthroscopic surgery for im right knee. He hope to return for July, but for June he do another operation wey rule am out for di rest of 2020. Dis month Federer say im face a ""tight"" race to be fit for di Australian Open, despite say dem push di tournament back three weeks sake of di coronavirus pandemic." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55467961 +entertainment BBNaija evictions today: Angel, Pere, Saga, Nini, Queen comot Big Brother house afta Ebuka announce dia name but twist dey - See wetin to know Saga, Nini and Queen don chop eviction from Big Brother Naija house. Queen na di first housemate to dey evicted on Sunday before Nini follow and den Saga Earlier on, Ebuka bin call Pere in front of di housemates say e chop eviction, but e later say e comot di house but not di show. E later call Angel as di second housemate to chop fake eviction from di show. Dis na di twist wey biggie bin warn about earlier on in di day. Afta di live eviction show, dem show Angel and Pere for di white room where biggie say dem go play a game wey go determine which one of dem go walk back into di house and which one go stay back. Na six housemates bin dey up for possible eviction for di ninth week, White Money, Pere, Angel, Saga, Nini and Queen. Biggie put di two housemates inside di white room to play wetin Ebuka di host of di show call 'double jeopardy' game. Di game involve toy trucks and di housemates go need to assemble dem together. Di first housemate to do so successfully go win di game and get di chance to waka go back inside di BBNaija house to continue di game for di last week. Dem go announce di winner on Monday. Dis na how di fans bin vote. Last week, Saskay and Yousef na im chop eviction from Big Brother Naija house to leave eight housemates left. Emmanuel wey win di ultimate veto power for di week afta one game dem play bin get immunity from nominations. Wit im power, e appoint Liquorose as Head of House and Cross as her deputy wey give dem immunity from nomination and assurance say dem go dey di house until di final week. Sunday eviction show go be di last eviction for di house before di finals. Earlier during di diary section, di housemates bin get mixed emotions but dem happy say dem make am up to di ninth week. Di ones wey dey up for eviction bin dey nervous as dem no sure wetin dia fate go be. During di diary session wit di housemates, Saga, Queen, Pere, Whitemoney, Nini and Angel tok how dem feel about di possible eviction. Saga say im dey super proud of imself because e believe say di platform go catapult am go places and give am exposure. Queen on her part say she dey fear, say if she comot di house dis night, e go pain her. Pere say im dey nervous as im no know if today na di end of di road for am for di game. Whitemoney say im get mixed feelings about di eviction and e go pain am if e gatz watch di finalist enjoy Biggie treats from house. Nini on her part tok say she sef dey nervous but she go choose to enjoy di day as e fit be her last day for di house. Angel tok say di eviction dey fear her, how her life go be afta di show. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58700385 +politics Adamawa govnorship election: Why Aishatu Dahiru Binani win for Appeal court dey important Appeal Court for Yola, Adamawa State capital, for north east Nigeria don declare Senator Aishatu Dahiru Binani as di ruling All Progressives Congress (APC) govnorship candidate for Adamawa State. Justice Tani Yusuf Hassan wey head di court case, throway di judgement of one Federal High Court wey bin nullify di govnorship primary and come declare say APC no get candidate for di 2023 govnorship election. Former chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, Malam Nuhu Ribadu wey contest for di ticket of di party but loss, bin challenge Binani victory for court. Im bin file case to nullify di primary wey dem do on May 27. Ribadu bin base im case on allegation of vote buying, over-voting and delegate enticement, come ask di court to disqualify Binani and declare am candidate of APC for di state. Im also want court order to prevent APC from submitting Binani name to Inec as di govnorship candidate of APC on ground say she be winner of invalid and unlawful exercise. Afta dem nullify her candidacy, APC and Senator Binani challenge di ruling of di lower court for appeal court. While APC challenge di jurisdiction of di court to entertain di mata, Binani for her preliminary objection argue say Ribadu no properly establish im case. She describe di case as useless, quarrelsome, bitter and contain allegations of fraud, claim say she commit crime, and therefore, court no go fit hear or determine di case sake of im originating summons. For im judgement on Thursday, di court of appeal order say make dem submit Binani name to di Independent National Electoral Commission (INEC) immediately. If Senator Aishatu Dahiru Binani, succeed to win di govnorship election, she go make history as di first woman to ever dey elected into di office of govnor, not just for northern Nigeria and di kontri as a whole. Northern states for Nigeria never fit break di spell wey dey prevent dem from getting female govnor. Indeed, Nigerians since im independence for 1960, never really fit elect woman to lead any state for di kontri. Although sha, two women don taste di position of govnor sake of some kain condition wey bin occur. Di first woman to ever first taste office of di govnor for short period na Virginia Ngozi Etiaba of Anambra state. For March 2006, Madam Etiaba become deputy govnor of Anambra state under Peter Obi. Later dat year, she become govnor afta di impeachment of her boss Peter Obi as govnor. She serve as govnor from 3 November 2006 to 6 February 2007 wen Obi return to office. Di second woman na Hadiza Sabuwa Balarabe, of Kaduna state. She become di current deputy govnor of di state for 2019 wit Nasiru el-Rufai as state govnor. Madam Balarabe get her chance to di position of govnor during di Covid-19 pandemic lockdown for 2020. Few months into di covid lockdown, govnor el-Rufai gatz hand over di office to her to become acting govnor afta im test positive for di virus. So far, na only dis two women don smell di seat of govnor, even if na for short time, dia by breaking di Nigeria political stereotype. https://www.bbc.com/pidgin/articles/czq3dg723ewo +sports Man Utd sign defender Maguire from Leicester hand for £80m "Manchester United don break record wit di $97m (£80m) wey dem don put down to sign Leicester and England defender Harry Maguire. Wit dis six-year contract wey Maguire sign for Old Trafford, im don become di world most expensive defender - to beat di $91m wey Liverpool pay for Virgil van Dijk for 2018. ""I happy well-well say I sign wit dis great club,"" Maguire follow tori pipo tok today. ""I enjoy my time for Leicester and go like to thank evribodi for di club and di fans for dia ogbonge support over di past two seasons. But wen Manchester United knock on your door, na big opportunity. ""E dey clear to see say Ole dey build team wey go win trophies. Now I wan meet my new team-mates to prepare for di season,"" di England international tok. Im na di third player wey United manager Ole Gunnar Solskjaer go sign dis summer, afta right-back Aaron Wan-Bissaka land from Crystal Palace for $61m and winger Daniel James join from Swansea for £18m. Solskjaer say: ""Harry na one of di best centre-backs for di game today." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49192100 +sports Aidan Dumuje Abili: Meet di fastest swimmer wey pipo dey call bullet Aidan Dumuje Abili na di fastest swimmer of im age category inside Lagos, Nigeria. Abili dey train six days a week, and he don make up im mind to become di next Michael Phelps (di fastest swimmer for di world). Di 8-year-old boy dey fast sotey im friend dey call am ‘bullet’. So far no Nigerian don ever win Olympic medal for swimming, but hum wan change that. Video Producers: Dan Ikpoyi, Gift Ufuoma https://www.bbc.com/pidgin/media-50385288 +business Ghana fuel consumers threaten court action if petroleum providers no reduce price "Consumer protection group for Ghana say if Oil Marketing Companies (OMCs) no reduce fuel prices by close of this week, dem go carry dem go court for what dem say be ""cheating"". Dem dey make dis demand after global crude prices drop from about $45per barrel to below $30. Executive Director for Chamber of Petroleum Consumers (COPEC), Duncan Amoah talk BBC Pidgin say ""check like Ghana here prices dey go up sooorn, if global prices come den dem no want reduce prices locally."" ""If all avenues for discussion, negotiations fail, dem go force we to take all of dem go court sake of dem dey cheat we."" Around 2015, petroleum regulator National Petroleum Authority (NPA) start dey implementation petroleum product price deregulation. What de deregulation system dey mean be say if global prices increase, local prices dey rise, wey if global prices fall then prices for reduce for local pumps. E be sake of dis deregulation policy wey for Chamber of Petroleum Consumers (COPEC) dey call for reductions soonest. ""World market prices go down, cedi make stable against de dollar, we dey expect say pump prices go reflect de gains but unfortunately de Ghana petroleum service providers no want do anything about am"" Duncan Amoah add. COPEC say make dem reduce prices by at least 10 percent, which go be like Ghc4.80 per litre from de current Ghc5.38 per litre." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51792717 +sports Liverpool v Arsenal: Reds take Gunners drink garri for 3-1 win Two goals from Mohamed Salah help Liverpool nack Arsenal 3-1 for Anfield. Joel Matip bin don open net for first half, afta Arsenal defend deep but allow many crosses from Liverpool full-backs. Na one of di corners wey follow see di defender jump pass im marker to score. Lucas Torreira score late goal for Arsenal, but by dat time e look like say nothin dem fit do again. Many go dey wonda how di match for take waka if di Gunners record signing Nicolas Pepe bin score one sweet chance im get for first half. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49462434 +business Nam 1: We go pay customers soon if Ghana gov’t unfreeze wana accounts – Menzgold CEO "Menzgold CEO, Nana Appiah Mensah say he want make government help en company make dem collect dema $39million dollars from Royal Horizon, de Dubai company wey dey owe am. He explain sey if dem support am plus international lawyers, dem fit secure en monies den take settle en customers. Nana Appiah Mensah meet plus de media today for de first time after dem detain am for Dubai den Ghana respectively. BBC Pidgin ask whether de Dubai court give specific time wey Royal Horizon for pay Menzgold de $39million dollars, Mr Mensah talk sey de court no give any specific time. ""One of de propositions be say we talk government sey make dem u freeze wana account sake of dem freeze wana account. So we go sit plus lawyers, engage plus de Attorney General den pursue that amount as soon as possible"" He explain say that no be de only asset dem get, as dem fit use dema other assets take settle dema liabilities to customers. Menzgold CEO, Nana Appiah Mensah also talk government sey dem for satisfy three conditions which go help am pay en customers. First wan make dem assist Menzgold retrieve dema monies wey other foreign companies dey owe. Secondly, he wan make dem unfreeze en company den personal bank accounts which go allow dem settle dema customers. Lastly, he go like make dem give clear directions on which regulator get jurisdiction den supervision over Menzgold business. Nana Appiah Mensah dey detention for Dubai since December 7, 2018, dem arrest am for de country on charges of defrauding en business partner for there. Last year, court issue bench warrant for en arrest on charges of defrauding by false pretence after Menzgold customers do demonstration over dema locked up cash. As he arrive Ghana security officials for Kotoka International Airport arrest am again, but currently dem give am bail as investigations continue." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49401242 +health Vagina health and sex: 24 things about vagina every woman suppose know "Many women no too sabi plenty things about dia vagina. Even for dis 21st century, tori about anatomy, monthly changes, hygiene and plenty tori wey dem fit dey experience still dey strange to some women. Some experts don put together some things wey fit help women understand dia female sexual organ [vagina] beta. Di vagina dey inside di body - na di elastic muscular canal wey connect di vulva to di cervix and di uterus. Vulva na di correct word to use wen you dey tok about di external part of di female sex organs. Na di vulva hold di pubis, urethral opening, clitoris, labia minora and the labia majora and vaginal opening. Di external structure of di vulva consist of di labia majora - dis na di outer lips of di vagina, di labia minora - di inner lips and di clitoris - one highly sensitive & erogenous zone wey get more nerve endings than any other part of woman body. Dis fit shock you. While men dey pee from their penis, women dey pee from di urethra (one tubular structure wey dey carry piss from di bladder to outside of di body). From front to back, di first hole na di urethra and then di vagina, wey dey above di anus. Public hair get work wey e dey do. E dey serve as protective barrier to di genital tissues and vaginal opening. E also dey prevent infection. Obstetrician-gynaecologist, Dr Jen Gunter say she notice say plenty women dey like shave dia pubic hair. She say e dey okay but e get risk. Dr Gunter add join say waxing or shaving of di pubic hair fit cause microscopic trauma to di skin, plus e fit cause cuts, abrasions, infections. Many women dey shy to tok about di pain dem dey experience during kerewa [sex]. However, E dey important to know say sex no suppose dey painful. Sabi pipo advise say if you dey experience any kain pain during kerewa visit your doctor or gynaecologist. Di glands wey dey located for di lining of di vagina dey release one fluid wey naturally dey designed to dey lubricate and cleanse di vagina. When you use some kain soaps or cleaning devices, dem fit cause react wit di vagina natural pH balance and cause infections like thrush. To avoid dis, apply soap for di outer labia only. Dr Gunter say you no need use anything clean inside di vagina. She warn against using scented douches alias bathing soap as e fit increase di risk of catching sexually transmitted infections. Steaming, another trend, no dey necessary, e fit lead to burns. You fit clean di outer part of di vulval area when necessary wit water or a gentle cleanser. Vaginal cells dey replace themselves every 96 hours - e dey quick heal. You still fit catch some STDs (Sexually Transmitted Diseases) even if you use condom. STDs like herpes, HPV, pubic lice and molluscum contagiosum still dey transferable. Dis na because di vulva still fit touch di blocus (or vice versa), during sex and dis fit cause infection. Most women no dey reach climax through vaginal penetration and sometimes dey need clitoral stimulation before dem fit experience orgasm. Dem fit achieve orgasm through masturbation, manual or cunnilingual stimulation by a sexual partner. Plenty lubrication of di vagina dey prevent painful sex and tissue tearing. Vaginal lubrication dey affected by di level of oestrogen for di body. Things like using birth control, menopause and breastfeeding fit change di oestrogen levels. Di lower your oestrogen levels, di more difficult e go dey for your vagina to lubricate naturally. As women dey grow old, di natural lubrication [wey be di wetness for di vagina] go dey dry up. Dem fit begin topical oestrogen treatments or manufactured vaginal lubricants to lubricate. If you get very dry vagina, you fit speak to your doctor and get solution. Whether you do operation (C-section) or you born naturally, most physicians dey recommend taking at least four to six weeks off before you begin kerewa, make di vagina for fit heal well-well. To dey get orgasm fit help relieve menstrual pain. Dis na because of di increase of blood flow wey dey occur during climaxing. In addition, when you orgasm, your uterine muscles go contract and release chemicals di brain wey go generate one natural pain reliever for menstrual cramps. Afta years of doing periods and maybe to born children, di ovaries go stop to dey produce eggs and menstruation go stop. Di amount of hormones for di body wey dey keep women fertile go drop dramatically - and low levels of oestrogen, in particular, dey affect di vagina and vulva. Vaginal farting [to mess] wey pipo sabi as ""queefing"", go happun to most women at some point for dia lives, especially during exercise and intercourse. Dis na because air dey escape from vagina and e go make dem dey mess. Pregnancy and childbirth fit change di vagina in plenty ways; Every single woman get different vagina odour sake of dia choice of fabric, from wetin dem like use as underwear, level of hygiene, diet, gland secretion and unique mix of internal bacteria. Di quality and quantity of vaginal discharge dey change sake of di different stages of your menstrual cycle. E usually dey be like off white wey look creamy tint when your cycle wan start. Small-small, di amount of discharge go dey increase as you dey near ovulation. When ovulation start, di discharge go dey thick small and e go dey pull when you touch am. E dey recommended make women do Kegel exercises afta dem born pikin to strengthen di vaginal muscles again. Kegels dey easy to do and you fit do am anywhere at any time. In order for sperm to survive and swim inside di vagina, di vagina dey maintain acidic environment wit a pH balance of 4.5. Douching dey considered to be more harmful than beneficial as e dey disrupt di natural balance of bacteria and fit lead to infection. Most women no dey ejaculate during orgasm, but if you do, beta for you. Female ejaculation fit occur as di result of two different phenomena wey most pipo no sabi. Ejaculation dey produced in a small amount wit a milky or cloudy appearance, e dey comot from di paraurethral glands wey dey inside di urethra. for women wey dey experience ejaculation, di sensation dey orgasmic and e different from wen women dey piss. Dis two structures resemble well-well. Just like di penis, di clitoris get di frenulum (di small fold and ridge of di skin wey support di motion) and a prepuce (or 'clitoral hood' na fold of skin wey cover am). Di clitoral hood dey comprised of di same kind of tissues wey make up di foreskin for males. Like di penis, di clitoris get erectile tissues wey dey stand upon arousal. Every woman vulva dey different, some labia majora (outer lips) dey inside and some hang down, some dey symmetrical and others asymmetrical. You get both long and short outer lips. Labia minora also different for dia appearance and size, and e dey important to remember that when you dey compare yourself to porn stars, many of dem don do labiaplasty procedures to cosmetically change di appearance of di labia minora. Di colour of vulvar anatomy also dey completely different from one individual to another, some get light pink, others na dark brown, etc. Di vaginal canal dey one angle for your body, dis na why sometimes during kerewa or wen you dey put tampon, e go be like say you dey hit wall. Women get their own version of di condition dem dey call 'blue balls' wey na men dey normally experience am. Na discomfort for di penis and/or testicles sake of sexual frustration." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56513949 +politics John Mahama vs Nana Akufo-Addo: Ghana elections 2020 economy and corruption score card Ghana elections 2020 campaigns don end, now de 7 December polls proper be upon us. So for help Ghanaians get better understanding of de issues affecting Monday voting, BBC Pidgin torchlight de west African country economy and corruption scorecard since 2012. Ghana election 2020 na majorly between two candidates wey don once serve as President for Ghana within de last eight years. Former president John Dramani Mahama of de National Democratic Congress [NDC] and de incumbent president, Nana Akufo-Addo of de New Patriotic Party [NPP] be de main contestants for Ghana 2020 presidential race. Dis time de two candidates dey ask for four more years to make Ghana great again. Make we take a look at some key sectors, wetin dema promise versus wetin dem achieve for dia first term for office. NDC Manifesto promise for 2012 To focus im economic development priorities to better di lives of Ghanaians through investment and development policies • Maintain single digit rate of inflation; • Ensure exchange rate stability • Reduce gbese significantly • Maintain average annual growth rate of at least 8% NPP Manifesto promise for 2016 To build di most business-friendly and pipo friendly economy for Africa, wey go create jobs and prosperity for all Ghanaians. Achieve double digit GDP growth annually for four years Reduce di cost of doing business, maintain financial discipline, reduce government borrowing and reduce interest rates to encourage private businesses. Tori pipo for Fact check Ghana bin do research and dis na wetin dem find out as dem quote World Bank data to compare di monetray value and di GDP under di tenure of di Mahama-led NDC government and di incumbent Akufo-led NPP. From dis table, e show say under di Mahama-led NDC government, Ghana record GDP growth of 15.836 wey be average of 3.959% growth every year. Akufo-led government don record an accumulated growth of 21.784% wey translates to an average of 5.446%. Dis one mean say di GDP of Ghana don grow higher under di NPP goment than di NDC. NPP manifesto for 2016 promise; To commit to establish solid, efficient machinery for good governance, wey go make up of accountable goment and respect for di rule of law and human rights. One of di things wey dem promise to do na to establish, by Act of Parliament, di Office of di Special Prosecutor, wey go dey independent of di Executive, Di special prosecutor go investigate and prosecute certain categories of cases and allegations of corruption and other criminal wrongdoing. All dis to ensure transparency for goment. NDC manifesto for 2012 promise; To stand gidigba to fight political corruption and immorality For di manifesto, di party promise to use di 2008 party promise to run di 2012 political tenure. For 2008, di NDC goment promise to deepen political accountability and transparency, disclose budgets, public expenditure and procedures. How tins be? For one statement wey NPP release afta di resignation of di Special Prosecutor on Monday, 17th November, 2020, di party say di record of corruption under di NDC leadership dey worst. Di Flagbearer of di NDC, John Mahama, during dia manifesto launch on September 7 for di University of Professional Studies, Accra condemn NDC performance on corruption. From wetin we gather from di Corruption Perception Index (CPI) report wey Transparency Index dey release every year to give insight on di presence of corruption in public office under a particular goment. See di table wey Fact Check Ghana draw up from Transparency Index report. Even though di CPI report for 2020 neva comot, di worst CPI score (di highest corruption perception) under di Mahama goment beta pass di best CPI score (di lowest corruption perception) under di Akufo-Addo NPP goment. Dis one mean say di Mahama led NDC goment handle corruption pass di Akufo Addo NPP goment. So now element number three which dey make Ghana elections exciting be say dis year, Ghanaians dey choose between govment which dey build infrastructure or govment wey dey strengthen economy. De opposition NDC John Mahama dey campaign on de grounds of en infrastructural achievement between 2012 - 2016. He build chaw top class hospitals, roads like circle interchange, new terminal for Ghana airport den stuff which more Ghanaians start dey appreciate after dem vote am out of power. Meanwhile, Prez Akufo-Addo too dey campaign on en record of economic transformation, growth in agriculture through planting for food and jobs, clean up of de banking sector, en handling of de COVID-19 pandemic den stuff. If Ghanaians vote give NDC, e mean say dem prefer physical infrastructure but if dem retain Prez Akufo-Addo, e mean say dem prefer say govment go build de economy. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55112945 +entertainment Osaru Obaseki: Benin female bronze maker wey dey break boundary Bronze casting na ancient tradition for Benin and di age long tradition na one wey be say e dey forbid women to cast bronze. Osaru Obaseki na young female experimental artist wey begin produce bronze pieces and so far, she don produce ova 15 bronze art pieces. She follow us yarn about her bronze art wey she say she dey use take promote Benin tradition. Video by: Dan Ikpoyi https://www.bbc.com/pidgin/media-57006011 +entertainment Emmanuella house: 10-year old Mark angel comedy star tok about her mother new house and plans she get for her parents "Popular young Nigerian actor Emmanuella open up to BBC Pidgin about di house she build for her mama. Di young comedian wey say e take her about a year to build di house say her mama deserve estate for everything she don do for her and say she still get oda ogbonge plans for her parents. You fit like to read: Her full name na Emmanuella Samuel, dem born her for July 22, 2010. She be 10 years old. She be from Imo state, wey dey for di south east part of Nigeria. For 2016, she collect award as di best new comedienne and princess of comedy for di Afro-Australia Music and Movie Awards for Australia. Still for inside dat same year, she win award for Top Subscribed Creator from YouTube for di first edition of di Sub-Saharan African YouTube Awards. Emmanuella Samuel, na child comedienne for Mark Angel YouTube channel wey get ova six million subscribers. She become popular for her comedy skit ""This Is Not My Real Face Oh"". She also get some endorsements for some big brands for di kontri. " https://www.bbc.com/pidgin/tori-54970441 +sports Nigeria vs Ghana: How Ghanaians and Nigeria react afta Black Stars qualify for World Cup "Ghanaians and Nigerians don begin react afta black stars qualify for Qatar 2022 World Cup yesterday. Nigeria footballer, William Troost-Ekong apologize on behalf of im team to all Nigerians for not security di world cup ticket. William Troost-Ekon post photo of imsef as e wear Nigerian jersey for im official instagram handle and write say; ""To all Nigerians, on behalf of di team, we want to apologise for not securing di World Cup ticket. ""Upon giving it everything possible, e no suppose end like dis."" ""First and foremost, as Nigerians, we share your emotions and we take our responsibility as a group."" ""We sincerely thank di Nigerian fans for dia big support, di NFF President wey do everything possible to make di qualification happen and of course di Minister. ""A bitter pill to swallow but believe me we go come back better and stronger!"" William Troost-Ekon conclude. Ghanaian dancehall artist, Shatta Wale put series of voice note for im Twitter handle to react as di black stars qualify for di world cup yesterday. For one of im voice note on twitter, e write say; #Qatar nightmare and for another tweet he write 'don't try Ghana.' Di singer continue to troll Nigerians and say e get new national anthem wey e won sing for Nigeria pipo as dem no qualify for di world cup. Nigerian child actor wey don turn comedian now, Williams Uchemba post for im instagram status say e good as Nigeria lost. ""Maybe e dey good say we lost so we go channel our anger on pressing issue for di kontri."" Williams Uchemba say if e take losing a match to get us angry and know di kind situation wey Nigeria dey, then e dey good. Ghanaian actor, John Dumelo share video of pipo wey dey celebrate for im instagram handle and write say; ""I tell you, dey be super CHICKENS!! congrats Black stars!!!"" Before now, , John Dumelo bin don promise for one instagram post say if Nigeria win on di first leg match, im go trek barefoot from Accra to Lagos di next morning." https://www.bbc.com/pidgin/world-60925537 +politics Kaduna State strike: NLC leaders in hiding, Nupeng threaten nationwide, as El-Rufai fire nurses - Day three updates "Leaders of di Nigerian Labour Congress, (NLC) dey in hiding for Kaduna state as di workers strike for di state enta day three. One of di leaders tell BBC say, dem need to hide sake of ""threat to dia lives"", afta Govnor Nasir ElRufai declare dem wanted sake of ""economic sabotage"". Dis na di latest on di Day 3 of di 5-day strike by NLC for di North western state. Labour leaders say dem don advise dia members to also comot from NLC secretariat sake of say some thugs dey hang around di place to possibly attack protesting workers. Di 5-day warning strike by NLC for Kaduna state take different dimension on Tuesday wey end wit di sack of all Level 14 Nurses for di state. Day 2 of di protest wey don lead to di closure of health centres, schools, filing stations, electricity stations and di state secretariat don become national issue. Some suspected jaguda boys attempt to hijack di demonstration of di workers after dem fail for di attempt to disturb di protest around di NLC Secretariat for Kaduna. As dat one dey happun, tori come out say di state govnor Nasir Elrufai declare Ayuba Wabba, National President of NLC wanted on top accuse of ""economic sabotage"". ""Ayuba Wabba & odas for NLC declared wanted for economic sabotage & attacks on public infrastructure under Miscellaneous Offences Act. Anyone wey know wia im dey hide should send message to @MOJKaduna. handsome reward go dey,"" Elrufai tok for tweet. Di events for Kaduna don attract attention from Nigerians, Civil society organizations, and even federal goment as all di stakeholders dey call on both NLC and goment to dialogue. Muyiwa Adekeye, wey be tok-tok pesin to Govnor Nasir Elrufai announce di sack of all Nurses for di state wey dey below level 14 sake of say dem join di strike for time wen di state dey battle emergency health situation. ""Salaries wey suppose go to dem go become extraordinary occupational allowances to di health workers wey no comot from dia duty posts to fill di gap of those wey run from work. ""We don direct di Ministry of Health to advertise vacancies for di immediate recruitment of new nurses to replace those wey we dismiss,"" Adekeye tok. Di national leadership of the Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) threaten say dem go shut down all of dia facilities nationwide if any dem wunjure any of di labour leaders. ""di union tok say make no labour leader or worker wunjure during dis 5-day peaceful protests for di state. ""NUPENG, therefore warn say if any harm dey inflicted on any of di members of organized labour, di leadership of di union no go hesitate to call on all our members throughout di nation for a total shut down of all our services for di upstream, midstream and downstream sectors of di oil and gas industry,"" di National President and General Secretary, Comrade Williams Akporeha, and Comrade Afolabi Olawale tok for statement. Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) don tell Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai to stop to dey harass workers wey dey protest for di state. SERAP for statement wey dia deputy director Kolawole Oluwadare sign tok say e dey wrong for Kaduna state govnor to declare Labour pipo wanted sake of protest. Di group say protest na human right and non of di labour leaders don violate any law as dem dey protest. ""Govnor, Nasir El-Rufai and Kaduna state authorities must end di harassment and intimidation of NLC leaders and withdraw di illegal statement wey declare Wabba and oda leaders wanted. ""To declare NLC leaders 'wanted' simply for peacefully exercising their human rights dey antithetical to di Nigerian Constitution of 1999 [as amended] and di kontri international obligations,"" SERAP tok. Nigeria federal goment intervene for di clash between di organised labour and Kaduna state goment. Minister of Labour and employment Oga Chris Ngige say make all di parties ""immediately ceasefire"". Deputy Director of Press and Public Relations for di Ministry of labour and employment for di statement wey im bring out on behalf of di Minister Ngige say dem dey aware of all di controversy wey dey happun between Labour and Kaduna goment. According to di Minister, ""Dis na labour matter wey don snowball into a national strike and picketing by the two labour centres and affiliate unions. ""We hope and also pray say make di Kaduna state Govnor no escalate matters to such level wia e go become uncontrollable. We also appeal to di leaders of di labour centres to step down di action to make way for discussion."" E tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57169326 +politics New year message: Projects wey President Buhari promise to do for Nigeria for 2020 Nigeria President Muhammadu Buhari for im new year message highlight projects wey im goment wan do for year 2020. Im say make Nigerians expect dis projects to come upstream from 2020: https://www.bbc.com/pidgin/tori-50970272 +sports Chelsea struggle, PSG, Real Madrid late winner and Erling Haaland goal headline champions league night Erling Haaland late goal against im former club Borussia Dortmund na im be di highlight of dis week Uefa champions league fixtures. Di finish see Haaland throw im sef across di ball and acrobatically volley am wit im left leg to beat goalkeeper Alex Meyer. Di goal begin trend for social media on di night – many pipo say n aim best goal be dat so far dis season for all competitions. Jude Bellingham na im put di German team for front before John Stones equalizer and Halaand winner. Anoda English side, Chelsea dey at di risk of crashing out of di UEFA Champions League. Dem bin dey lead 1-0 courtesy of Raheem Sterling but RB Salzburg shock dem wit a late goal by Nigerian - born Noah Okafor for Stamford Bridge. Di match on Wednesday night na di first game of new coach Graham Potter wey take over from Thomas Tuchel. Di Blues bin dominate di first half but dem no fit score until Sterling break di defence. Di result don leave Chelsea for di bottom of Group E afta two games. Also, Kylian Mbappe become PSG joint leading Champions League goalscorer afta dia win over Israeli side, Maccabi Haifa. Maccabi score di first goal wit Tjaronn Chery goal in di 24th minute for di Sammy Ofer Stadium. Goals from Messi, Mbappe and Neymar give PSG win for di game. Mbappe goal make im 30th Champions League goal for di club, drawing level wit Edinson Cavani. For oda games, Napoli hammer Rangers 3-0 for Glasgow. AC Milan also get 3-1 victory against Dinamo Zagreb. Real Madrid score two late goals to beat RB Leipzig 2-0. Copenhagen and Sevilla end in 0-0 draw while Shakhtar and Celtic also settle for 1-1 draw. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2vl5ql485do +sports Atalanta vs Man United: Prediction, team news for di Champions League match "Manchester United manager Ole Gunnar Solskjaer don give update on im team ahead of dia Champions League clash wit Atalanta. Di Reds dey flying to Italy for dia first-ever meeting for di Gewiss Stadium, afta dia 3-0 victory for Tottenham on Saturday. Man United dey top Group F wit six points ahead of Villarreal and Atalanta wey get four points and Young Boys wey get three points. ""Di pressure on Manchester United manager Ole Gunnar Solskjaer don reduce small afta dia 3-0 win for Tottenham on Saturday. Na wetin football sabi Bolarinwa Olajide tell BBC Pidgin we torchlight di game for us and share im prediction. ""Dem dey go into dis game as narrow favourites to win. Im add put Atalanta don only win one of dia last four games, and dem go miss key players like Gosens, Pessina and Djimsiti e continue. Man Utd suppose win, but you never know wetin to expect from di Red Devils. Atalanta vs Man United go kick off by 9pm West African time on Tuesday, November 2, 2021. For Gewiss Stadium, also known as di Atleti Azzurri d'Italia. Na Cable Company Supersports wey dey for DSTV go broadcast di match live. If you dey reason to watch am for Nigeria and Ghana. Paul Pogba dey available for di visitors afta e miss out dia win for Tottenham sake of im suspension for Premier League. Anthony Martial fit also make di squad but Amad Diallo fit no dey available. Solskjaer go need decide whether to stick wit im 3-5-2 formation switch afta Raphael Varane return back to di team, wey see am play Cristiano Ronaldo and Edinson Cavani up front. Rafael Toloi still no dey available for Atalanta but forward Luis Muriel fit start afta e make dia on the bench for dia Saturday 2-2 draw with Lazio." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59127082 +entertainment Met Gala 2021 New York red carpet: Kim Kardashian, Rihanna, Billie Eilish, Megan Fox, Blackpink fashion top Met Gala red carpet pictures "Met Gala - one of fashion biggest and starriest events - don roll out im red carpet for New York for some of di planet best-known celebrities. Di event na to raise fund for di Metropolitan Museum of Art's Costume Institute, di Gala return afta dem bin don delay am last year sake of di pandemic. And although im famous guests must follow Covid-19 rules, wey include wearing masks indoors, wey no stop many pipo from all di glamour. Dis year costume theme na ""In America: A Lexicon of Fashion,"" - and di looks dey inspired by everytin from di Matrix film franchise to di Statue of Liberty. Na pop star Billie Eilish, tennis player Naomi Osaka, actor Timothée Chalamet and poet Amanda Gorman co-host di ball. One of di most talked-about looks of di night na di publicity machine wey be Kim Kardashian - she cover her face and body in an all-enveloping black outfit. Na Demna Gvasalia, the creative director of fashion house Balenciaga design di custom outfit Di 23-time Grand Slam winner Serena Williams made a statement of more colourful kind, as she wear one star-spangled bodysuit beneath a feather-laden pink cape. Other attendees, meanwhile, brought along props to accompany dia outfits. Without apparent explanation, singer Frank Ocean carry one green robotic baby, while musician Grimes brandished a sword. Among di last to arrive at di Gala was Rihanna - wey don steal di show at past events, wit outfits including one Pope-inspired costume for 2018. Di singer and businesswoman turn heads once again as she pose for one all-black Balenciaga overcoat, while her boyfriend, rapper A$AP Rocky, wear imself one multicoloured quilt. All images subject to copyright" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58555268 +politics Adams Oshiomhole: Victor Giadom say Appeal Court judgement no favour Abiola Ajimobi as APC Acting national chairman afta Oshiomhole suspension "Na confusion evriywia as Nigeria ruling All Progressive Congress (APC) change dia party national chairman three times inside less than 24 hours. Na sake of to clear dis confusion make Victor Giadom explain give BBC Pidgin why im on Wednesday morning take over as APC Acting national chairman, hours afta di party National Working Comming first appoint former Oyo State govnor Abiola Ajimobi to replace Adams Oshiomhole wey chop suspension. Latest tori be say di APC National Working Committee (NWC) appoint Hilliard Etta to act on behalf of Abiola Ajimobi wey no dey disposed, but Victor Giadom say all dat one na for dia pocket. E no too tey afta Appeal Court for Abuja rule say di party national chairman Adams Oshiomhole suspension wey FCT High Court grant for March 16 dey valid, na im di party NWC declare Sen. Abiola Ajimobi as acting national chairman. Some hours later, di deputy national secretary of di party Victor Giadom declare imsef as acting national chairman base on di March 16 High Court decision. Oga Giadom tell BBC say, ""I no declare mysef di chairman. Di court order make I serve as acting national chairman. ""I become acting national chairman of dis party through valid court order wey dem give on di 16 of March 2020, and dem neva change di order so I no know wetin di mata be. So until dem cancel di order, I still be di national chairman of APC."" But somehow, e be like APC national working committee no recognise di court order, as few hours later dem post for dia official Twitter page say dem ""unanimously appoint di party national vice chairman for south south, Hilliard Etta to act on Abiola Ajimobi behalf."" On top di appointment of Hilliard Etta, oga Giadom say di tok na for dia pocket becos ""if court order dey and dem no cancel di order, you no fit go do anytin else, anytin you do outside dat order dey invalid."" Im nullify all Oshio Baba decisions since March including di screening for Edo govnorship candidates. Tori say Victor Giadom declare im sef national chairman of di ruling APC based on Abuja High Court order of March 16, 2020 no be news again. But how Giadom take land for di centre of dis party politics? Sogboge Eli, na member of APC and insider for activities of di party, im explain say some of di top positions for di party bin dey vacant during di time wey di FCT High Court order Giadom to take charge of di party. ""By di time di order come, di NWC wey national chairman Adams Oshiomhole dey don suspend di deputy national chairman north, di deputy chairman south dey vacant becos di last official, Niyi Adebayo, don become minister of di federal republic and di south west wey dem zone am too neva fill di position. ""And den di national secretary position too dey vacant becos Mai Mala Buni, go become govnor of Yobe state for northeast Nigeria, so di only senior na di deputy national secretary wey bin dey act as national secretary. In terms of seniority, Victor Giadom na di most senior officer so im come become acting national chairman."" For pesin wey no bin dey really follow Edo politics before dis time, plenty kwesions fit dey im mind unto how di katakata for di party take reach wia e dey today. For some time now, Oga Adams Oshiomhole AKA 'Oshio Baba' for short and di state govnor Godwin Obaseki bin don dey get kwanta unto who dey run di state. Kasala burst for di state APC for June 2019 afta nine out of 24 State House members gada dem sef elect principal officers for di Edo State House of Assembly. Oshiomhole bin no like di result of di election. Di kwanta enta anoda level wen on Tuesday 12 of November 2019, APC chairman from 18 local goments areas of Edo state suspend Adams Oshiomhole as dem pass vote of no confidence on top. Beginning from Oshiomhole ward, ward 10 of Etsako Local Goment Area, to di local goment proper reach state levels, di party ratify im suspension according to di law. Based on di ratified suspension, for January 2020, di deputy chairman of di party for North East, Comrade Mustapha Salihu plus odas file ex-parte application before Justice Danlami Senchi of Federal High Court, Abuja make Oshio Baba stop to dey parade imsef as di national chairman of APC. On March 4, Justice Senchi wey grant di order say political parties must to obey dia constitution, and as im don chop suspension from im ward Oshiomhole no suppose dey work as party chairman. On March 16, Justice Senchi also order make ""Chief Victor Giadom to handle di matas of di 4th defendant (APC) as acting chairman and to chair all di meetings of di national executive committee of di 4th defendant wey dem fix for 17 March, 2020 or any oda date wey dem fix pending di hearing and di decision of di Motion of Notice."" But dat same day, di embattled chairman sharply cari di mata go Court of Appeal collect ""stay of execution plus appeal di ruling."" According to Oga Eli, one of di tins wey Oshio Baba do as ""im resume office as national chairman na to lift di suspension of di deputy national chairman north Comrade Mustapha Salihu, den get Ajimobi to take di position of deputy national chairman south west, den put Bulama to step in as national secretary."" Finally, Appeal Court for Abuja take decision for Oshiomhole prayer to stay execution and appeal Justice Senchi High Court ruling. Di Court of Appeal judgement wey Justice Eunice Onyemanam pass confirm High Court decision to suspend am national chairman of APC. Di court also withdraw all im right and priviledge as di party national chairman including im security men. As tins be so, di Nigeria ruling All Progressive Congress get two acting national chairmen to run di party. According to di party constitution, na only di national executive committee or di national convention of di party members fit to solve dia katakata wey dey dia di goment party apart. Di APC dey face di risk of losing two states govnorship elections wey go happun for Edo and Ondo state if dem no solve di crisis." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53085873 +entertainment Grammy nominations 2023 full list: Beyoncé lead wit 9 nods, Kendrick Lamar follow wit 8 "Nominations don enta for di 65th annual Grammy Awards. Beyoncé dey di top wit nine nominations, all but one na for her dance album ""Renaissance""; di oda one na for ""Be Alive,"" from di feem ""King Richard."" Dis number don make am a total of 88 career nominations wey she don get, di same as her husband, rapper Jay-Z, wey get five nominations dis time. Two of dem dey tied as di most-nominated artists for Grammy history. As Beyoncé dey lead, na so oda artists like Kendrick Lamar dey her back wit eight nominations; Adele and Brandi Carlile, wit seven; and Harry Styles, Mary J. Blige, Future, DJ Khaled get six each. Di ceremony go shele on 5 February, 2023. Beyoncé no be di only artist to make history as superstar Bad Bunny land album of di year nomination for ""Un Verano Sin Ti,"" wey become di first all-Spanish album to eva appear for di category. Who go win golden award for one of music biggest nights? Keep reading to see evri artist wey dey nominated: Record of di Year Album of di Year Burna Boy gbag two nominations for Best Global Music Performance and Best Global Music Album. Dis go be di third year in a row im go get nominations for di Best Global Music Album category, first for im African Giant album and then for im Twice As Tall album wia im bin win. Howeva no be di only pesin for di region wey dey nominated for music biggest night. Nigerian star, Tems follow her wins for 2022 wit nomination for Best rap son for di Future song Wait For U wey feature her and Drake inside. Tobe Nwigwe bin dey nominated for Best New Artist, Eddy Kenzo don become di first Ugandan to dey nominated;, Zakes Bantwini and Nomcebo Zikode both from South Africa follow for di Best Music Performance nominees. Angelique Kidjoe too follow hold award nominations for Best Global Music Performance and Best Global Music Album as well as Best Song Written For Visual Media. Song of di Year Best New Artist Best Pop Solo Performance Best Traditional Pop Vocal Album Best Pop Vocal Album Best Dance/Electronic Recording Best Dance/Electronic Music Album Best Rock Performance Best Rock Song Best Rock Album Best Alternative Music Album Best R&B Performance Best Traditional R&B Performance Best R&B Song Best R&B Album Best Rap Performance Best Melodic Rap Performance Best Rap Song Best Rap Album Best Country Solo Performance Best Country Duo/Group Performance Best Country Song Best Country Album Best Latin Pop Album Best Latin Rock or Alternative Album Best Tropical Latin Album Best Folk Album Best Reggae Album Best Global Music Performance Best Global Music Album Best Song Written for Visual Media Best Remixed Recording Best Music Video Best Music Film" https://www.bbc.com/pidgin/world-63643240 +health Coronavirus - Virus: How social distancing fit slow down di Covid-19 pandemic "World Health Organization - WHO recommend 'social distancing' as one of di ways to protect against coronavirus, and goments don dey advice pipo to do am. But wetin e really mean? To make am straightforward, social distancing mean say make pesin try to avoid touch-touch wit oda pipo, especially di ones wey dey show signs of di disease. E also mean say make pesin no dey spend too much time outside, wia pipo plenty. WHO wey be di global health joinbodi believe say social distancing fit epp to slowdown di spreading of Covid-19 (in addition to washing of hands, and to cover mouth during coughing). Although all those tins by demsef no go stop di spread of di disease, according to WHO Director General Tedros Adhanom Ghebreyesus wey tok on 16 March. E say instead na testing and isolation go be di way to 'break di chain' of coronavirus. For one social event wey happun for Lagos, south-western Nigeria over di weekend, di organisers bin tell BBC di red carpet no go dey jampack. And every media company go get dia own separate area to make sure say guests no mix anyhow. On Monday, 16 March, Prime Minister of Britain Boris Johnson don advice citizens to work from dia house and no gada togeda to jolly as di kontri death toll number don rise to 55. ""Dis blockade ontop outside jolly-jolly fit last for months or at least weeks,"" tok di UK number 1 doctor, Chris Whitty. On 15 March, South Africa presido Cyril Ramaphosa declare for national speech say schools go dey closed and travel ban go dey. On top of dis, all gatherings of more than 100 people don dey ""prohibited"". One day later, Ghana goment impose ban on all public gatherings like conferences, funerals, festivals, political rallies, church services, Islamic worship for 4 weeks starting Monday, 16 March, 2020. Also goments of western kontries don begin advice dia citizens to practice social distancing, including United Kingdom, United States and Australia." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51923354 +entertainment Cynthia Morgan and Jude Okoye: Wetin happun to Madrina change of Record label no dey new - See oda Naija musicians wey don get yawa wit dia managers Many Nigerians waka enta social media on Sunday to tok about musician, Cynthia Morgan afta one Instagram live she do - reveal why her music career no too solid again. Di 29 year old Nigerian raggea dance-hall singer explain say na afta she accept one contract from her former record label - North Side Music Ltd - oga Jude Okoye, wey be music producer. Ms Morgan say she no read di contract terms before she sign am and e affect her career well-well as she lost her stage name, Instagram account, royalty and VEVO account. But Jude Okoye neva come out to reply all di claims wey she make for di Instagram live, but on Sunday e tell Tunde Ednut for separate Instagram live say all di allegations wey Cynthia Morgan put for im head no be true. However, wetin she tok don cause plenty gbas-gbos for social media and oda pipo wey dia music career don enta gear one afta dem get yawa wit Jude Okoye or dia managers don also come out to tok dia own tori. No be only Cynthia Morgan go get kwanta wit her manager, we sabi like four pipo wey get swey don bounce and odas still dey try find dia leg for di industry. Madrina (Cynthia Morgan) change her name for September 2017 but di tori and for pipo because of di new song wey she release for May 2018. Peter Okoye shook mouth for di mata, e say three years ago wen im decide to comot for Jude Okoye record label no be because of fame, money or power but na because of im freedom. May D wey react to wetin Cynthia Morgan tok, claim say im no gain anytin wen im too bin dey under di record label. Di Nigerian singer, song writer and dancer wey real name na Akinmayokun Awodunmila carri di complain enta Twitter. Kizz Daniel bin get issues wit im manager Tumi Lawrence and im fire am. But wetin make am get issues wit im manager no dey clear. But tori be say di singer and im manager bin get issues. before dem pat ways. Di singer wey bin dey under di Chocolate City Record lable bin get kwanta wit im managers Di singer and song writer wey real name na Olawale Ashimi also port from Chocolate city afta dem get issues like dis Cyntia Morgan mata. Popular Nigerians singer 2Baba wey real name Innocent Idibia bin get issues wit im former label KENNIS Music before im come port to im own Hypertek label. Altho e no dey clear di nature of wetin dia disagreement be. Na afta im port from Kennis Music na im e change im name from 2Face to 2Baba. Singer Davido also shook mouth for di mata for twitter say im get anthem for her, say make she call am. Former Big Brother Naija star, Tacha say di mata tire her and she sorry for Ms Morgan One popular Nigerian radio pesin Tolu Oniru AKA Toolz also react as she indict her friends say na hand wey get oil pipo dey follow leak no be hand wey get blood. Popular comedian, TV Host and actor AY don ready to support Cynthia https://www.bbc.com/pidgin/tori-52791098 +sports Kamaru Usman vs Gilbert Burns: Usman beat Gilbert with TKO for thrid round of UFC 258 "Kamaru Usman retain im title for Mixed Martial Arts as im knock-out Brazilian Gilbert Burns for di second round but win am afta round three. Burns bin give am better punch for di first round but for di second round na Usman show im self sotay pipo bin dey tok say im dey fight like ""bus stop fighter"". For post match interview, im tok say im be di best for a reason and say ""everibodi need to put respect for my name."" Dis one mean say Usman retain im belt as di Welterweight champion, as im tok for di end of di match wen e say ""Put some respect for my name."" Usman make history as na im be di UFC Welterweight fighter wey don get di longest winning streak with 13 straight wins back to back. Di fight bin suppose to happun for July 2020 but dem bin postpone am to December afta Gilbert Burns bin catch coronavirus. Di December fight bin also dey postponed because Kamaru bin get injury. So far, Kamaru Usman don win 19 out of di 20 matches for im carer and im and Burns get history to as dem use to train for di same gym for Florida wia im bn help di 34 yea old Brazilian. Dis na Burns first UFC match. Many pipo don dey tok for inside social media about di match." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56053178 +politics Ghana Presidential election results: Check out 42 Day timeline for John Mahama petition hearing "Ghana opposition leader, John Mahama file petition for de apex court of de land to challenge de results of de 2020 presidential elections. Per new Supreme Court rules wey parliament enact in 2017, Supreme Court (Amendment) (No.2) Rules, 2016 (C.I. 99) make am clear say dem go determine presidential election disputes within 42 days. Dis be how de process go play out within de 42 days for Supreme Court of Ghana. Day 1 one de 41 days dey start from de day aggrieved presidential candidate go file en petition. Reference point for dis be statement wey Chief Justice, Justice Anin Yeboah make before elections 2020. ""Supreme Court introduce strict timelines for management and hearing of presidential election disputes which dey require court to determine on de 42nd day after filing. What dis dey mean be say de counting of 42 days dey start from December 30, 2020 when de petitioner, John Mahama file en election petition. Day 10: Deadline for 1st and 2nd Respondents to answer Per de timelines wey Supreme Court make available for de hearing, respondents for answer to de court within ten days after dem file de petition. So de 1st Respondent, Electoral Commission of Ghana and 2nd Respondent, Nana Akufo-Addo both for answer to de court by day 10. After Day 10 where de expectation be say respondents to de petition by John Mahama answer to de courts through dema lawyers, de Supreme Court go start what dem dey call ""pre-trial hearing."" For de uninitiated mind, pre-trial hearing simply dey like dress rehearsal for de main hearing for de Supreme Court. Lawyer Martin Kpebu, explain give BBC Pidgin say dis pre-trial hearing like how media dey test camera, sound, lights, den other equipment before dem go go on air live plus news. On day 15, de hearing dey proper dey begin with de witnesses of all parties involved mounting de witness stand to give account den tins. Dis be where lawyers go cross examine, ask questions, shoot down claims of dema opponents den stuff. Day 21: Hearing Ends After de hearing start on day 15, dis hearing go continue for 21 days during which de Supreme Court judges go hear from de petitioner, 1st respondent and 2nd respondent. After de 21 days, de Supreme Court Judges go sit on de matter den consider de arguments wey all de parties make, de evidence dem bring forward, de merit of dema case and reliefs wey de petitioner dey seek den pass judgment on day 42. After dem pass judgment on day 42 de whole election petition end." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55497562 +sports Manchester City vs Liverpool FA cup: Match preview, where to watch FA cup semi finals "Manchester City vs Liverpool go continue dia rivalry as dem go meet for di FA cup semi-final today. Saturday match na major test for Jurgen Klopp men wey dey plan to become di first English team to win four major trophies for one season. Di two teams don meet for different competitions plenty times. Manchester City and Liverpool play out very entertaining 2-2 draw for dia top-of-di-table clash for di Premier League last Sunday. Manchester City coach Pep Guardiola no dey sure whether Kevin de Bruyne and Kyle Walker go dey fit to play Saturday FA Cup semi-final for Wembley. Di two players comot as substitutes afta dem suffer leg injury during di Champions League quarter-final second leg tie against Atletico Madrid on Wednesday. ""De Bruyne get stitches for im calf, no be muscular injury. Walker get big twist but e dey get better"", Guardiola tok. For di oda side, Liverpool say dem dey assess Diogo Jota afta suffer knock during dia 3-3 draw wit Benfica on Wednesday. Apart from dat, di Reds no get oda injury concerns. Dia players no also dey on suspension. Di fact say Liverpool close down over point gap wey Manchester City bin give dem for premier league na sign of massive development for di Reds. And for di number of times wey di two coaches don meet, Klopp don show more capacity dan Guardiola. Di match last weekend wia dem play 2-2 na anoda sign say dis match no go easy. But from analysis by pundits wey be sabi pipo for sports dem believe say Liverpool go win dis match. Prediction: Manchester city 1-2 Liverpool Liverpool and Manchester City don begin resemble modern football biggest rivalry. Some sabi pipo don compare dia maches to di El classico for Spain. Di two clubs dey hope to win several trophies dis season. Di Reds coach Jurgen Klopp don already tok say im go play dis FA cup semi-final game like say na final. ""We must to go all-in,"" di German tok. Di two clubs don play plenty times. Manchester City don win: 58 Liverpool win: 105 Draw: 56 Both of di weekend's semi-finals are available on free-to-air TV inside UK. City clash with Liverpool is on BBC One TV network on Saturday. Kick-off time for today semi-final na 3.30pm. TV Coverage of di game go begin at 3pm. A few Premier League games go still get underway at di same time." https://www.bbc.com/pidgin/sport-61127173 +politics Femi Fani-Kayode: FFK don join APC? See wetin Yahaya Bello and odas tok "One recent video of wia di Kogi State Governor Yahaya Bello say di former Nigeria Aviation Minister wey be strong member of di opposition party, di Peoples Democratic Party don join di ruling party, All Progressives Congress (APC) don make some Nigerians dey para for social media wit di hashtag #GetOutFFK. Governor Yahaya Bello afta im go revalidate im All Progress Congress Membership for im home kontri Agassa, for Okene Local Government Area, Kogi state tell tori pipo say to welcome Fani-Kayode to di APC na one of im work as di head of di mobilization committee for di party membership registration and revalidation. He say ""Our brother and friend, Chief Femi Fani-Kayode, don join our party in good faith. He dey join our party to come add im own positive energy and make contributions to ensure say APC na party to beat."" ""Remember, Chief Femi Fani-Kayode na foundation member of di All Progressives Congress but e comot sake of misunderstanding… Now he don decide to join our party, he approach me and by di mandate wey our party give me, I must not segregate,"" the governor tok. One of di media aide to di governor confam to BBC Pidgin say di video na true as e happun on di 9th of February, one day afta di PDP stalwart Chief Femi Fani-Kayode meet wit di Nat. Chairman of the APC, Gov. Mai Buni of Yobe state & Gov. Yahaya Bello of Kogi state. We neva reach oga Kayode to confam if wetin di governor tok na true but im don tok about di mata for im verified Twitter handle say ""I neva comot from di PDP."" E no tey afta Fani-Kayode meet wit di Govnor of Yobe State and Chairman of APC Mai Buni, tori begin run viral for social media say oga Kayode wey currently be PDP member don join APC again. But on Wednesday, FFK post anoda set of pictures for im verified social media platform wia e tok about one meeting im hold wit former President Goodluck Jonathan wey be chief for Nigeria main opposition Peoples Democratic Party. He say ""I go advise Nigerians to be very careful about fake quotations wey pipo dey claim say na me tok concerning oda political leaders inside di kontri. If you no read am on my verified twitter handle or my verified Facebook page den I no ever ""NEVER"" tok am. Period."" Di former Aviation Minister drop dis words of caution just afta tori begin fly upandan say im [FFK] don re-join Nigeria ruling All Progressives Congress [APC] #FFKGetOut begin trend for Nigeria Twitter as Nigerians enta social media to reveal how oga Kayode take rubbish di party and im members before wit im posts, interviews and statements. Some APC leaders and members don tok say e no dey welcomed to di party sake of some of di fabricated stories, insulted, damage and distorted information e don tok about di party and dia leaders. Director-General of di Progressive Governors' Forum Salihu Moh. Lukman kick against any attempt to admit oga Kayode to di party as e go dey against di values of di party. Femi Fani-Kayode na 59 year old Nigerian politician, essayist, poet and lawyer. Fani-Kayode don comot PDP two times in di past to join APC. Fani-Kayode be Special Assistant (Public Affairs) to President Olusegun Obasanjo from July 2003 until June 2006. E collect anoda appointment as Minister of Culture and Tourism of Nigeria from 22 June to 7 November 2006 and as Minister of Aviation from 7 November 2006 to 29 May 2007." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56021784 +sports Euro 2020 fixtures: Predictions and everything you need to know about European Championships After some delays due to Coronavirus pandemic, di European Championship alias Euro 2020 go start for Rome Stadio Olimpico on Friday and e go end on 11 July for Wembley. Uefa European Championship be like World Cup, but just for European teams. E go consist of 24 teams and 51 matches for 11 host cities across Europe, although e no dey clear how many fans go dey allowed into stadiums for di tournament, because of di ongoing global health crisis. All 24 teams for di final tournament dey guaranteed to play at least three games before di top performers for di group stage go move on to di knockout phase. From that point, every game go be sudden death: win and teams reach di next round, lose and you go go home. Group A: Italy, Switzerland, Turkey, Wales Group B: Belgium, Russia, Denmark, Finland Group C: Ukraine, Netherlands, Austria, North Macedonia Group D: England, Croatia, Czech Republic, Scotland Group E: Spain, Poland, Sweden, Slovakia Group F: Germany, France, Portugal, Hungary For di first time for di history of di tournament, 11 cities na im go host matches for di expanded version of di competition. Di 11 Euro 2020 host cities include: Amsterdam, Baku, Bucharest, Budapest, Copenhagen, Glasgow, Munich, London, Rome, Seville and St Petersburg. Dublin and Bilbao bin originally dey as host cities but miss out on hosting games after dem no dey able to guarantee spectator attendance. Seville na new Euro 2020 host city. Uefa switch di four matches wey bin dey initially scheduled to take place for Bilbao to di Estadio La Cartuja. Di venue go host about 30% of di stadium capacity. Di three Group E matches wey dey initially scheduled for Dublin go now take place for St Petersburg Stadium for Russia. Di round of 16 match wey suppose hold for Dublin don dey moved to Wembley. 1. Glasgow (Hampden Park, capacity 51,000). Three group games, one last-16 game. 2. London (Wembley, 90,000). Final and both semi-finals, two last-16 games, three group games. 3. Seville (Estadio de La Cartuja, 60,000). Three group games, one last-16 game. 4. Amsterdam (Johan Cruyff Arena, 54,000). Three group games, one last-16 game. 5. Copenhagen (Parken Stadium, 38,000). Three group games, one last-16 game. 6. Munich (Football Arena Munich, 70,000). Three group games, one quarter-final. 7. Rome (Stadio Olimpico, 68,000). Three group games, one quarter-final. 8. Budapest (Puskas Arena, 68,000). Three group games, one last-16 game. 9. St Petersburg (Krestovsky Stadium, 61,000). Six group games, one quarter-final. 10. Bucharest (Arena Nationala, 54,000). Three group games, one last-16 game. 11. Baku (Olympic Stadium, 69,000). Three group games, one quarter-final. Teams go dey allowed to select 26-player squad instead of di usual 23 for dis summer's tournament. Dem implement di change to reduce di load on players after compressed club season because of di coronavirus pandemic. E go also help managers adapt if outbreaks occur during di tournament. Teams dey allowed to make up to five substitutes per game. However, 23 players go remain di maximum number wey dey permitted on team sheets for matches. Alan Shearer: France go win am. Dem get talent all over di pitch. Gary Lineker: E dey hard to look beyond France - dem bin lose di final five years ago, dem win di World Cup three years ago and now dem Karim Benzema too. Dem go dey improved and dem get brilliant young players too. Dem gatz be favourites. Portugal no be outsider because dem win di tin four years ago but dem get very good team and dem get chance. Micah Richards: Belgium go win di Euros because Kevin de Bruyne - di best midfielder for di world - go light it [di tournament] up. Di team get di experience now wey dem need too. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57432830 +health Coronavirus Fake News: BBC never report say Ghana confam first case of Covid-19 "BBC want draw attention of de public to fake story which dey make rounds say ""Coronavirus: Ghana confirms first case in the University of Ghana"" be fake. De perpetrators write fake story wey dem put BBC News branding for top. BBC News want state clearly say dis story no be true, so make everyone ignore as Ghana no record any case of coronavirus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51854801 +politics Emeka Ihedioha: Supreme Court don adjourn di former Imo state govnor case to March 2 Supreme Court don adjourn Emeka Ihedioha case to March 2nd 2020 to review di judgement wey comot am as govnor of Imo State. Di Court adjourn afta Ihedioha lawyer, Kanu Agabi ask di court to give am time to enable am reply to all di process wey di lawyers of Hope Uzodinma serve am. Na afta e ask for adjournment, di Chief Justice of Nigeria Muhammad Tanko, wey dey preside ontop di mata ask di court to shift di case go next month. Dis dey come afta di seven-man panel of di highest court on 14 of January 2020 give judgment wey remove Iheodioha as di Governor of Imo State and declare Senator Hope Uzodinma as di winner of di last governorship election for di State. Justice Kudirat Kekere-Ekun, wey read di lead judgment for Uzodinma appeal ruling, say di votes for 388 polling unit out of di 3,523 polling units dem no include am for di election result wey INEC collate and so afta dem add di result, e show say na senator Hope Uzodinma win di election. Di court judgement don cause plenti reaction as many Imo pipo don enta street to protest di judgement plus di PDP, di main opposition party don do I-no-go gree plus petition join give US, EU and UK goment to chook mouth for di mata. Na sake of dis, Ihediaoha cry go di Supreme Court to ask dem to reverse di judgement and remove Hope Uzodinma as di govnor of Imo State and install am back. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51542324 +entertainment Baba Suwe burial: Nollywood celebrities wey attend Baba Suwe burial in pictures Nollywood actors gada for di burial of Babatunde Omidina popularly known as Baba Suwe for Lagos on Thursday. Baba Suwe die for di age of 63 afta small sickness, according to wetin im son confam to BBC Pidgin. Sola Omidina, say di Nigerian comedian die around afternoon on Monday, 22, November, 2021 Di burial of di late actor and comedian hapun for im house for Ikorodu, Lagos state, south west Nigeria. Nollywood actors gada for im house to pay dia last respect. Dem born Babatunde Omidina aka Baba Suwe on August 22, 1958, for Inabere Street for Lagos Island. But di legendary actor come from Ikorodu local goment area of Lagos. E marry e wife, Omoladun Omidina wey also be actor for 1995 and she die for September, 2009. Di popular actor bin attend Jamaitul Islamial Primary School for Lagos, and Children Boarding School, Osogbo. After im boarding school, Baba Suwe bin get im West African School Certificate for Ifeoluwa Grammar School for Osogbo, Osun State, southwest Nigeria. Baba Suwe begin acting career for 1971 and e bin act for both English and Yoruba language films. Di veteran Nollywood comedian dey often play di role of confuse servant or security guard. E become popular afta e feature in one movie titled, Omolasan. Im become more popular afta e act for Iru Esin wey Olaiya Igwe produce for 1997. Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin arrest Baba Suwe afta dem accuse am of trafficking cocaine for 2011. As di agency put am for custody sake of say dem want make e excrete di cocaine wey dem suspect say e dey im stomach, nothing come out of Baba Suwe belle. Di agency chop blame ontop di case and court come judge say make dem pay Baba Suwe more than $155,000 as compensation and apologise to am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59413310 +entertainment Lyta new record label: Naira Marley sign Opeyemi Babatunde Rahimto MarlianMusic months afta disagreement wit Olamide YBNL Nation "Lyta, wey be young Nigerian singer on Wednesday reveal say im go soon drop im next single. Di announcement wey Lyta drop form im Instagram page land just one day afta Popular Nigerian singer, Naira Marley sign di 22 year old singer to im record label. On Tuesday, Marley post for im Twitter page to share one picture of Lyta wit document wey appear to be a record deal, wit di caption: ""Welcome to MarlianMusic Lyta."" Lyta say im dey so excited to join wetin im call im new family Marlian music and also thank Naira Marley. Naira Marley bin launch im own label for January, 2020 MarlianMusic wen e sign four artistes—Zinoleesky, Mohbad, Cblack, and Fabian — during one ogbonge concert alias 'Marlian Fest' inside Victoria Island, Lagos. Dis dey happun just one year afta e bin join Doro Music and release im popular single, 'Monalisa,' Tori be say Lyta wey real name na Opeyemi Babatunde Rahim, na singer and songwriter. Di Nigerian singer sign a record deal wit YBNL Nation in 2018 but e leave di label in May 2019 afta e bin get disagreement wit Olamide. Di association no end on di best of terms as Lyta accuse legendary artist, Olamide of some questionable things. Olamide respond to Lyta inside one open letter. Lyta release im 5-track debut EP Id in 2019 and 4 July 1998 dem bon di 22 year year old Ajegunle based singer" https://www.bbc.com/pidgin/53755188 +sports Chris Eubank son Sebastian don die for Dubai, tributes pour in for am "Boxer Chris Eubank son Sebastian don die, few days before im 30th birthday, im papa representatives don tok. Sebastian wey bin follow im papa for back also become professional boxer imsef. Di British middleweight Eubank Snr tok say im and im family dey ""devastated"" to hear of im son death for Dubai - wia im dey live. And Chris Eubank Jnr tweet: ""Rest easy little brother, I love you and we go miss you always."" Sebastian, di third-eldest of Eubank Snr children, leave behind im wife Salma and son Raheem wey dem born one month ago, according to Eubank Snr. The Sun newspaper bin report say dem find di deadibodi of Sebastian afta im drown for beach. For statement Eubank Snr say: ""Sebastian grow up for Hove in England but in di last few years e don settle down for Dubai. ""Ontop say im na personal trainer and professional boxer, Sebastian na also deep thinker wey like to challenge di way most pipo dey reason. Im mama Karron Meadows tok say: ""Our whole family dey grieve for di big loss of our son and brother, Sebastian."" Former world boxing champion Joe Calzaghe, YouTuber and boxer KSI dey among those wey pay tribute to Sebastian. ""E really turn me for belle to hear di tori say Seb Eubank don die. Thoughts and Prayers go out to Chris and family,"" Calzaghe tok. Sebastian promoters and agents, Kalle and Nisse Sauerland, describe am as ""true gentleman and sincere human being"". Promoter Eddie Hearn add im own: ""I dey sad by di news of Seb Eubank death. Our thoughts and prayers go out to im family and friends."" Eubank Snr, 54, na di WBO middleweight and super-middleweight champion between 1990 and 1995 and im dey undefeated in im first 10 years as professional." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57770589 +sports Champions league result: PSG vs Istanbul Başakşehir match chop suspension afta Pierre Webo allegation of racism "Di match between Paris Saint Germain and Istanbul Basaksehir suffer suspension afta one of di match officials face accuse of allegedly using racist term against one of di away team coaching staff. Cameroonian Achille Webo, assistant coach of Turkish club Istanbul Basaksehir, say e allegedly suffer racist insults by 4th referee. Report say de fourth referee allegedly call assistant coach, ""Negro"" weh e mean black man. Webo say deh sack e from field before, Sébastien Coltesu, Romanian, referee, call'am 'Negro'. All de players and coaches leave di stadium afta playing only 10 minutes of di match. Uefa say di match go resume on Wednesday by 7pm. Cameroon roving ambassador, legendary player don send encouraging words for e broda, Achille Webo. Turkish president don condemn suspicion for racist tok for PSG - Turkish side match. Cameroonians don take dia vex for Facebook as deh say no to racism." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55242152 +sports Alex Iwobi: Di midfielder transfer from Arsenal make Nigerians squeeze face "As di transfer window close for English Premier League on Thursday 9th August, di news say Arsenal don sell Alex Iwobi to Everton touch many Nigerian football fans for mind well-well. Tori be say dem sell di 23-year-old Nigerian player for almost £34m ($41m) to di Merseyside club minutes before di deadline reach. Iwobi bin join di London club wen im small, and spend 17 years with dem, e recently play for di Africa Nations Cup for Nigeria, wia im win bronze medal. Im transfer come as surprise to many Nigerians wey dey follow Premier League well-well and millions of fans for West Africa wey dey support Arsenal. Dem enta Twitter to para, di fans say everything bin dey go well for Arsenal ""until di transfer"" BBC Africa Sport tori pesin Debola Adebanjo, wey dey based for Lagos, post for Instagram say she be ""ex-Arsenal fan"" now. Former Nigeria International and ex Arsenal player Kanu Nwankwo wish Iwobi good luck for im new club." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49295740 +sports "Tiger Woods accident: Eldrick Tont ""Tiger Woods"" car crash for traffic collusion for Los Angeles" "Tiger Woods, di 15-time Golf Major winner dey hospital afta e suffer car accident wit plenti leg injuries. Dem don rush Tiger Woods wey real name na Eldrick Tont go hospital afta e involve for car wreck for traffic collusion, according to di Los Angeles County Sheriff's Department. Di police department say dem ""respond to one single vehicle rollover"" accident wia di ""vehicle sustain major damage"". Los Angeles firefighters and paramedics ""remove di American professional golfer from di wreck"" Dem come take di 15-time golf major winner to one local hospital by ambulance to treat e injuries. Woods' agent Mark Steinberg say: ""im currently dey undergo surgery and we thank una for ua privacy and support.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-56159869 +politics Senator Elisha Abbo decamp from PDP to APC - See why di Nigerian senator take dis decision "Senator Elisha Abbo don announce im defection from di opposition Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC). For inside letter wey im address to di National assembly, di Senator wey dey represent Adamawa North for di Senate announce say im don comot from di PDP. Senate President Ahmad Lawan read di letter during Wednesday plenary session. For inside di letter, Senator Abbo say im decision to join di APC dey come sake of how dia Adamawa state Governor Umaru Fintiri dey mismanage di PDP party for di state. Senator Abbo bin dey for news last year sake of say im assault one woman for one adult toy shop for Abuja, di kontri capital. But im explain give BBC Pidgin say ""Dis tin happun long before I become senator, not now. Dem no report am dat time, na now I win election dem go dig up di video. E happun for Abuja, Bannex Plaza on March 11, 2019."" One High Court for Abuja award N50 million damages against Senator Abbo, as compensation to Osimibibra Warmate, di female attendant for di sex-toy shop, wey im assault. Senator Elisha Abbo win election as PDP candidate on February 23, 2019 to represent Adamawa North Central Senatorial district." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55073446 +sports Ese Brume, Blessing Oborodudu and Samuel Takyi win historic first medal for Tokyo 2020 Olympic games Africans win medals wella on Day eleven of di Tokyo Olympic games. Blessing Oborududu win silver for di women's freestyle wrestling as her compatriot Ese Brume claim bronze in di women long jump as dey gbab Nigeria first medals in Tokyo. Namibia Christine Mboma be di first Namibia woman to ever win Olympic medal just weeks after dem tell am say she no fit compete in 400m wey she like play sake of high levels of testosterone. Two Egyptian wrestlers go fight for bronze medals on Wednesday after dem loose semi-final bouts on day 11. Ugandan Joshua Cheptegei and Jacob Kiplimo get chance to win their second medals in Tokyo, to go wit di ones dem don win in di men 10,000m, as they qualify for Friday final of di 5,000m. Liberia American-born Joe Fahnbulleh beat world champion Noah Lyles and set new national record as e reach Wednesday final of di men 200m. Ghanaian boxer Samuel Takyi be settle for bronze medal as e loose im featherweight semi-final but e win im kontri first Olmypic medal since 1992, di men football team also collect bronze. Nigeria 25 year old Ese Brume win di kontri first athletics medal in Tokyo when she win bronze for di women long jump event. Her best leap of 6.97m dey just three centimetres behind winner and reigning world champion Malaika Mihambo of Germany, but 20cm short of the African record she set in May. Brume mark dey actually di same as Brittney Reese but di American gbab di silver medal because her second longest jump of 6.95m pass Nigeria Brume next best leap. Christine Mboma win silver in di women 200m to become di first Namibian woman wey go ever win Olympic medal. Di 19-year-old also break di world world under-20 record for di third time in Tokyo as she run 21.81s in di final. Mboma finish behind Jamaica Elaine Thompson-Herah - wey retain her title, complete di sprint double in Tokyo and run di second fastest time in history, She also become di only second Namibian athlete to ever win Olympic medal after Frankie Fredericks, wey win four silver medals during im career. Her fellow kontri woman Beatrice Masilingi set new personal best as she finish sixth just behind Ivory Coast's Marie-Josee Ta Lou in fifth. Di two Namibian athletes drop down from di 400m event wey dem want after World Athletics bodi bin tell dem say their testosterone level pass di limit dem fit allow for female athletes to compete over that distance, unless dem medically lower their testosterone for like six months. Nigeria Blessing Oborududu win silver as she lose to USA Tamyra Marianna Stock Mensah for di final of di women 68kg freestyle event to gbab her nation first ever Olympic wrestling medal. Di 32-year-old lose 4-1 on points to di American for di bout. Ghana Samuel Takyi settle for bronze medal for Tokyo as e lose e featherweight semi-final 4-1 on points to di USA Duke Ragan. Di 20-year-old medal na di first one for Ghana since di men football team win bronze for di 1992 Games in Barcelona. Ghana other three Olympic medals all come in boxing wit Clement Quartey winning a silver in 1960, Eddie Blay and Prince Amartey claim bronzes at di 1964 and 1972 Games . Takyi medal be di only one for Africa in boxing in Tokyo. Joshua Cheptegei from Uganda wey dey right and im kontri man Jacob Kiplimo for left both reach di final of di men 5,000m at di Tokyo Olympics Joshua Cheptegei jeje enter final of di men 5,000m as im dey reason e second medal for Tokyo games, after e win silver in di me 10,000m on Friday. Im kontri man Jacob Kiplimo, di bronze medallist from di 10,000m, finish just ahead of Cheptegei as dem both progress finish for top five of di second heat. Ethiopia Milkesa Mengesha be sixth for di same heat, e gbab place of fastest loser but Lesiba Mashele of South Africa no dey quick enough to advance while Kenya Samwel Masai no even start. Kenya's Nicholas Kipkorir Kimeli win di first heat as e qualify automatically for di final, wit Uganda Oscar Chelimo also progressing in fourth. Liberia American-born Joe Fahnbulleh set new national record as e qualify automatically for Wednesday men 200m final. Di 19-year-old pip USA world champion Noah Lyles on di line for second place for photo finish in their semi-final, di two men given 19.99 seconds. Nigeria Divine Oduduru manage third for di first semi-final just ahead of Ghana's Joseph Amoah but di two men no record enough time to progress as fastest losers. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58076504 +entertainment The Future Awards Africa 2022 Winners list: Tems, Bimbo Adeyemo, odas win for dis year event "Future Awards Africa don announce winners for di 16th edition of di awards. Di event happun for Lagos, South West of Nigeria on Sunday 20, February, 2022. Di TFAA na annual awards wey dey celebrate young pipo between di ages of 18 and 31, wey don make outstanding achievement for di year under consideration. Di organisers say dis awards dey celebrate trailblazers wey don choose to defy di status quo and redefine di norm for dia various fields within di past year. Making di list of dis year award nominees na di founder of Chess in Slums Africa, Tunde Onakoya;, Social media influencer and popular #EndSARS campaigner, Rinu Oduala. Ogbonge Kannywood actress Maryam Yahaya, Plateau-born fashion model, Davou Pwajok and Nigerian Afro-Fusion singer, songwriter and record producer Daniel 'BNXN' Benson also gbab nomination for dis year TFAA. On-Air-Personality, Nancy Isime go host di 16th edition of The Future Awards Africa, di Central Working Committee of The Future Awards Africa tok am for inside statement. ""Nancy Isime wey also be past winner na inspirational actress and exceptional host. She carry di fierce determination of a challenger and di child-like inquisition of a builder, so for her to host di Awards na perfect choice."" di organisers tok. The Future Awards Africa prize for content creation Isaac 'Zicsaloma' Aloma (30) Tayo Aina (29) WINNER Onyekelu 'Jenni Frank' Jennifer Ebere (27) Apaokagi 'Taaooma' Maryam (22) Emmanuel 'Mr Funny' Ejekwu (26) Tobi 'Street Church' Oreoluwa (31) The Future Awards Africa prize for advocacy & activism Solomon Ayodele (29) Wilson Atumeyi (29) WINNER Rinu Oduala (23) Fatima Tafoki (24) Naima Idris Usman (27) Shedrack Danladi (29) The Future Awards Africa prize for community action Vera David-Emesiobum (31) Tunde Onakoya (27) WINNER Blessing Ingyape (31) Saratu Ishaya Abdullahi (27) Aliyu Sadiq (24) Ibrahim 'Flag boy' Adebanjo Akinwunmi (25) The Future Awards Africa prize for music Joseph 'Joeboy' Akinwale Akinfenwa-Donus (24) Adedamola 'Fireboy' Ade Folahan (26) Oyinkansola 'Ayra Starr' Aderibigbe (19) Chukwuka 'Ckay' Ekweani (26) Stanley 'Omah Lay' Didia (24) Daniel 'Buju' Benson (24) Temilade 'Tems' Openiyi (26) WINNER The Future Awards Africa prize for professional service Adeyemi Adetunji (29) Daphne Akatugba (31) David Oyawoye (24) Khalil Nur Khalil (28) WINNER Abiodun Animashaun (30) Blossom Egbude (24) The Future Awards Africa prize for acting Teniola Aladese (28) Maryam Yahhaya (24) Nengi Adoki (31) Temi Ami-Williams (24) Emeka Nwagbaraocha (24) Abayomi Alvin (27) Bimbo Ademoye (30) WINNER The Future Awards Africa prize for journalism S.I Ohumu (26) WINNER Abdulbaqi Aliyu Jari (30) Laila Johnson-Salami (25) Yvonne Okhaifoh (28) Chisom Peter Job (19) Agbaje Ayomide (22) Elfredah Kevin-Alerechi (32) The Future Awards Africa prize for lawyers Oyinkansola 'Foza' Fawehinmi (25) WINNER Mobolaji Oriola (27) Damilola Wright (29) Iredumare Opeyemi (32) Oluwaseun Ayansola (27) Kelechi Ibe (27) The Future Awards Africa prize for film Akay Mason (28) Kayode Kasum (30) WINNER Dada 'Oluwadabest' Temitope (29) Victor Edem (25) Nora Awolowo (22) Abdul Tijani 'Abdul TJ"" Ahmed (27) The Future Awards Africa prize for entrepreneurship Omoye Abulimen (28) Olatunji Adenike Rukayat (28) Lade Lois Olaiya (27) Jerry Mallo (27) WINNER Jumoke Dada (27) Ore Runsewe (31) Joel Ogunsola (28) The Future Awards Africa prize for technology Kennedy Ekezie (24) WINNER Abubakar Nur Khalil (22) Dare Adekoya (22) Yanmo Omoregbe (28) Timi Ajiboye (28) Hanu Fejiro (26) Eluan Ben (24) The Future Awards Africa prize for art and literature Chigozie Obi (24) WINNER Mayowa 'Shutabug' Alabi (27) Niyi Okeowo (27) Renike Olusanya (27) Eloghosa Osunde (29) T.J Benson (30) Arinze Ifeakandu (27) The Future Awards Africa prize for health and wellness Dr. Chinonso 'Aproko Dr' Egemba (31) Dr. Chioma 'Dr Zobo' Nwakanma (29) Dr. Princess Ifeoma Ike (29) Dr. Cassandra Akinde (30) WINNER Dr. Opeyemi Adeyemi (29) Dinatu Emmanuel Ishaka (26) Odunola Olabintan (25) The Future Awards Africa prize for academic achievement Mufid Sulaiman Abubakar (29) Ikanna Okim (23) Asaka Ewerechukwu Favour (21) Goodness Adesewa (24) Uchechi Promise Echefu (29) Joseph Oloruntola Adeola (28) Uzoaku Odinachukwu Amadi (24) Joy Adesina (24) Elizabeth Ekeoseye (21) The Future Awards Africa prize for fashion Weiz Dhurm Franklyn (30) WINNER KIING DAVIIDS (28) Temitayo Ilesanmi Nathan (28) Seun Olopade (28) Bolajo Fawehinmi (30) Mariam Afolabi (28) Davou Pwajok (24) The Future Awards Africa prize for service to young people Femi Falana Tony Elumelu Aisha Yesufu Dr. Akintoye Akindele Ooni Adeyeye Enitan Ogunwusi Atedo Peterside Olowogboyega A. Olayemi The Future Awards Africa prize for young person of the year Mohamed Salah (Egypt) (29) Angeline Makore (Zimbabwe) (32) Jerry Mallo (Nigeria) (27) Andrea Iyamah (Nigeria) (28) WINNNER Lelise Neme (Ethiopia) (29) David 'Davido' Adeleke - 2017 The Future Awards Africa prize for music winner. Ayodeji 'Wizkid' Balogun - 2017 The Future Awards Africa prize for young person of the year Timini Egbuson - 2019 The Future Awards Africa prize for acting Damini Ebunoluwa 'Burna Boy' Ogulu - 2019 The Future Awards Africa prize for music Israel Adesanya - 2019 The Future Awards Africa prize for sports" https://www.bbc.com/pidgin/tori-60454375 +health Nigeria dey behind Sierra Leone, South Sudan for WHO ranking of kontris wey no fit protect pikin health "Nigeria dey among bottom kontris wey no fit protect pikin health, dia environmemnt and future of dia children. Tori be say one new report from World Health Organization togeda wit ogbonge researchers for Lancet wey dem release Tuesday night tok say Nigeria dey 174 position behind Afghanistan, Sierra Leone and South Sudan. Di report, wey dem title- A Future for di World Children compare di performance of child wey dey prosper among 180 kontries of di world. Claes Johansson, UNICEF Nigeria Representative tok say: ""Dis don show how far we still need to go for Nigeria to make sure say children fit live healthy lives for environment wia dem fit prosper."" "" We know say to invest for di future of our children, give dem education and make sure say dem dey healthy and dey receive di right nutrition, go help provide beta future for everyone. We all get responsibility to do everything we fit do to protect di health and future of everi Nigerian child."" Di ranking dey based on factors wey include means of how pikin dey survive and well-being like health, education, nutrition, equity and income gaps. Organizations wey join hand do dis ogbonge report na World Health Organization (WHO), UNICEF and The Lancet and na yesterday dem release am. Di report find out say di health and future of every child and adolescent all ova di world dey under serious threat from ecological degradation, climate change and marketing practices wey dey take advantage of children-dat na to entice children with heavily processed fast food, sugary drinks, alcohol and tobacco. According to di report, no single kontri dey really protect children health, dia environment and futures well-well. But e show say children for Norway, di Republic of Korea, and di Netherlands get di best chance of survival and well-being, while children for Central African Republic, Chad, Somalia, Niger and Mali face di worst. Dem advice Nigeria to among oda tins do di following: To protect children, di independent Commission authors call for new global movement wey go dey focus on children. Dia recommendation include: 1.Stop CO2 emissions wit di sharpely-sharperly, to make sure say children get future for dis planet 2.Place pikins and young adults dey for number one category to achieve sustainable development 3.Put new policies and investment inside all sectors wey go target pikin health and rights. 4.Hear from di children and add dia voices for any policy decisions 5.Tighten national control of commercial marketing wey dey harmful to children, and support am wit di new Optional Protocol to di UN Convention on di Rights of di Child." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51556150 +entertainment Cute Abiola not missing: Navy detain comedian Abdulgafar Ahmed - Lawyer Cute Abiola dey missing? Dat na wetin many fans of di Nigerian comedy skit maker dey ask. Di comedian Cute Abiola wey real name na Abdulgafar Ahmed bin reportedly go missing on Monday 15 November, 2021. Lawyer to di Nigerian comedian however tell BBC Pidgin on Wednesday morning say im customer dey allegedly detained by Nigerian Navy. Fatai Adebanjo say di Nigerian Navy no tok why di skit maker dey for detention. Adebanjo say cute Abiola wey also be Navy Personnel bin resume for im office for NNS Ojo, one maintenance unit of di Nigerian Navy for Lagos state on Monday morning. But on Tuesday morning, when e dey expected for house, e no show. Dis make im wife dey worried begin call friends and associates. Na dia tori bin go viral say e dey miss. Di lawyer say na when e land di Navy office to sabi im whereabout, e discover say e dey cell and nobody dey give information on im offence. One popular comedian Debo Adedayo aka Mr Macaroni bin raise alarm on top social media say cute Abiola dey miss. However, informate wey BBC Pidgin gada, im arrest fit relate wit one recent picture e share for im 4.2m followers on top Instagram wey show as e hold AK 47 inside one feem. Dis according to Navy dey against dia rules, for personnel to carry gun wen e no dey do operations. Dis no be the first time cute Abiola go dey arrested because e go against di Navy rules of engagement. According to reports, e dey detained last year sake of say e pose wit im official uniform during im birthday wey e post on social media. Di Nigerian Navy say cute Abiola no dey miss, contrary to tori wey dey spread. Statement wey Navy release dis morning on top di mata say dey di comedian dey wit dem. Di skit maker wey real name na 'Abdulgafar Ahmed breach di Armed Forces Social Media policy and e refuse to obey particular orders.' Na wetin Commodore Suleman Dahun sign for di statement on behalf of Chief of Naval Staff. Abdulgafar Ahmad Oluwatoyin, aka Cute Abiola na Nigerian comedian, wey also be Naval officer, entertainer and video producer. E dey popular for im comedy skits on social media. Dem born am for Ilorin, Kwara State, north-central, Nigeria. E start im career as comedian when e dey secondary school. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59316169 +entertainment Dilip Kumar: What to know about di Bollywood legend wey die at di age of 98 Ogbonge Bollywood star and one of India earliest and most famous actor, Dilip Kumar, don die at di age of 98 years. Kumar di legend, bin act for more dan 65 films inside fifty years and im acting style make im fans love am. Dem admit am for hospital on June 30 afta im complain say im no fit breath, but before den, im don dey fall sick frequently. Im dey survived by im wife, Saira Banu wey also be Bollywood actress, but dem bin no get any pikin. Dilip Kumar name wen dem born am na Mohammed Yusuf Khan. Dem born am on 11 December 1922 for Peshawar - wey dey now for Pakistan - before dem partition India. Kumar begin ansa Hindu name wen im join di Hindi film industry - just like oda Muslim actors wey be im mates. Di first India film wey im act na Jawaar Bhata wey im act for 1944. But na di film Andaz, wey im bin act for 1949 make am blow. Na only one film Kumar eva produce for im career and dis na for 1961 For 1966, im marry im wife Saira Banu and dem two act togeda for many films wey popular. For 1976, Kumar take five year break from acting den continue again for 1981 Di last time wey Kumar appear for film na for 1998. Kumar collect many correct awards plus two of India highest civilian awards. Im get record as actor wey don win di highest number of Filmfare Award for Best Actor. Im do politics briefly, and between 2000 and 2006, im serve as member of di upper house of di India parliament. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57754300 +entertainment Justin Bieber say e start to dey use drugs at di age of 13 "Justin Bieber don tok say di way e bin dey take drugs wen im bin dey young na sometin wey dey ""legit crazy scary"". E tok dis one for di latest episode of im YouTube series ""Justin Bieber Seasons"", di singer tok say e bin dey addicted to drugs and cannabis wen e be 13 years old. E say, ""Pipo no sabi how serious e bin dey. I bin dey wake up for morning and di first tin I go do na to take drugs, smoke joint come start my day."" Di 25 year old pop star don tok about im drug abuse and abusing im relationship before, but dis latest video na di first time e dey tok about am for camera. Justin Bieber tok about times wey e go do ecstasy and mushrooms wey dey turn brain sotay, im security team go dey check im pulse for night to make sure say e still dey breathe. Infact, im wife Hailey tok for di show say she bin decide say she no go involve herself for im life, until ""im decide to go sober."" Di singer tok say na as im hard am to cope with im fame na im make am to start dey take hard drugs. Di series also show di star dey use oxygen mask to reduce im stress, anxiety and depression and how e dey work with brain disorder sabi person. Last year, di Biebs take break from music to repair ""some deep rooted mata dem"" but announce before Christmas say e go come back dis year with album and US tour." https://www.bbc.com/pidgin/world-51363993 +sports Amaju Pinnick don win election to continue as oga of Nigeria football Current presido of di Nigeria Football Federation Amaju Pinnick don win im re-election to continue as oga patapata. For election wey happun on Thursday for Katsina State, Pinnick nack three odas wey follow am contest to win di position. Di result wey di NFF Electoral Committee release show say Amaju Pinnick get 34 votes, Aminu Maigari - 8 votes, Taiwo Ogunjobi - 2 votes and Chinedu Okoye - No vote. Dis result mean say Pinnick go do four more years as di presido of di football federation until 2022. https://www.bbc.com/pidgin/sport-45590573 +politics Edo Governorship election 2020: Timeline of di battle to lead di state from 2019 and wia e dey now "As Edo govnorship election don near finish, and di two big political parties dey campaign seriously to win di votes and hearts of di pipo. Two candidates na im all eyes dey on to see who go las las win di election. Govnor Godwin Obaseki and Pastor Osagie Ize-Iyamu. Di journey to today no be smooth one as di Edo and indeed Nigeria don witness some kain drama between di two main parties wey dey contest for di election and dia candidates, di Peoples Democratic Party candidate (PDP) wey be di current govnor of di state, Godwin Obaseki and di All Progressives Congress (APC) candidate Pastor Osagie Ize-Iyamu. Pesin fit tok say di drama begin right after Godwin Obaseki - of den APC - become govnor of di state, to replace who many bin believe to be im godfather at dat time - Adams Oshiomhole. Until Obaseki later resign from APC, di ruling party bin dey control 21 states while opposition PDP bin dey im charge of 15 states. Make we look back to how di palava start. Shock as pipo wake up to hear say Edo House of Assembly don inaugurate nine of dia 24 members secretly. Tori be say dis quick move na to prevent Oshiomhole supporters not to get mouth for running of tins for di state. ""Edo own na 9.30 pm, wey be unholy hours. Dat na night hours. Di working hours for parliament dey inside di rules of di parliament. E no dey for any pesin hand to change those rules only properly constituted parliament fit change di rules as dem dey,"" Oshiomhole bin tok some days later on 22 June. Govnor Obaseki sack eight commissioners. Tori be say dis na pipo wey dey loyal to di den APC National Chairman Oshiomhole Afta one panel wey National Assembly bin don setup to torchlight mata for Edo, one Federal High Court chook mouth for di mata and order di National Assembly to comot hand for di state. Pastor Osagie Ize-Iyamu, wey be governorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) for di 2016 election announce say im don port go APC, di ruling party. One Abuja High Court stamp di suspension of Oshiomhole say make e hold since di Edo State chapter of im own party still put am on suspension, wey im appeal di next day. In wetin go be di month wey get drama pass for di Edo crisis, June na di one time Obaseki imsef begin see wehn! Dem disqualify Obaseki on di basis say im certificate im submit for school no pure. One court for Abuja rule say Oshiomhole appeal no hold water and im suspension must remain. - Later on di same day, APC appoint Abiola Ajimobi to replace Oshiomhole as National Chairmo. - Obaseki defect from APC, di ruling party to PDP, as rumours begin fly say im don join new party. Days afta e comot APC, im announce say im dey renew im bid to run for di state govnorship under PDP ticket. Gov Obaseki give order say make dem comot roof of di House of Assembly. Many believe say dis move na so that lawmakers no go fit do sitting for di building. But di assembly building bin dey under renovation. President Muhammadu Buhari endorse Osagie Ize-Iyamu in di place of im 'friend' Obaseki. Dis dey come just two months afta Pastor Ize-Iyamu port comot from di kontri main opposition Peoples Democratic Party (PDP) to join di ruling APC for di southern state of Edo. Convoy wey Oshiomhole dey inside been get accident wey claim di lives of two policemen. Di former APC national chairman imsef survive. Ize-Iyamu inside message for Twitter allege say based on how one big truck take jam di convoy, e reason am say di accident na attack to take di life of Oshiomhole. But everitin no be fight with dis big players for Edo State, because even with kwanta, when tori comot say Oshiomhole get road accident, na Obaseki still comot public message to wish am well." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53984186 +entertainment Bruce Willis: Razzies cancel 'worst performance' award sake of health issues "Organisers of Razzie Awards, wey dem dey give to di worst feems of di year don cancel di recent ""honour"" wey dem give actor Bruce Willis afta di announcement about im health issues. On Wednesday, im family reveal say im get brain disorder wey dey known as aphasia. Ceremony bosses say e ""no dey proper"" to award prizes to pipo wey dia medical conditions fit don affect dia performance. Dem bin give Willis im own category for worst Bruce Willis performance for 2021. Out of di eight feem wey dem nominate, dem judge Cosmic Sin as di best winner. Di oda movies wey dey drag di award bin include American Siege, Apex, Deadlock and Out Of Death. Razzies release di names of di pipo wey go collect dis year award wey dem dey also call di Golden Raspberry Awards, on Saturday. Some days later, announcement come say Willis dey step away from im acting career afta hospital discover say im get di condition wey affect pesin ability to speak and write. Willis, 67, popular for im role wey im play as John McClane for Die Hard feems, wey make am star. Razzie organisers say dem reach dia decision afta ""much thinking and consideration"". ""If pesin medical condition na factor for dia decision making and/or dia performance, we acknowledge say e no dey proper to give dem Razzie,"" dem tok. Di American actor wey pipo sabi from oda feems like Armageddon and The Sixth Sense go retire from acting afta dem diagnose am with aphasia wey be condition wey dey make am difficult for pesin to tok or write. Na im family, plus im wife, Emma Heming-Willis and ex-wife Demi Moore, announce dis one on Instagram on Wednesday, 30, March. Di statement tok say, aphasia ""dey affect im cognitive abilities"". Willis, wey be 67 years, dey popular for im character as John McClane for di Die Hard feems, wey make am celeb. Im family write for joint statement say, ""wit plenti consideration Bruce dey step comot di career wey mean alot to am. Dis na very challenging tim for our family and we dey very grateful for una continuous love, compassion and support"". Willis get five daughters, three wth Ms Moore and two Ms Heming-Willis. According to di National Institute on Deafness and Other Communication Disorders (NIDCD), Aphasia na disorder wey dey result from damage to portions of di brain wey dey responsible for language. For many pipo, dis area dey for di left side of di brain. Di disorder dey normally occur suddenly, maybe afta stroke or head injury, but it fit also start slowly, sake of brain tumour or progressive neurological disease. E dey make am hard for pesin to read, listen, tok, type or write but na di toking palava dey common pass as di pesin wey dey suffer di disorder fit dey put words togeda wrongly. Dem born Willis as Walter Bruce Willis on March 19, 1955, for West Germany. E start im acting career for early 1980 but but e no blow until di ABC TV series Moonlighting and den for 1988 performance wen e act as John McClane for di first Die Hard film. Since den, im feems like The Sixth Sense, Armageddon and Pulp Fiction don gross more dan $5bn worldwide, according to Variety. Im don dey nominated for five Golden Globes. E win one for Moonlighting, and e don win two Emmys. Several actors and oda stars don offer dia condolences to Willis and im family afta di news of im diagnosis. ""Grace and guts! Love to you all!"" actress Jamie Lee Curtis write for response to Demi Moore's post. ""Sending lots of love and healing to you all!"" na wetin journalist Katie Couric write." https://www.bbc.com/pidgin/world-60937580 +sports BTS Star Jung Kook, odas totori fans for di 2022 Fifa World Cup opening ceremony "BTS star Jung Kook na im first perform for di opening ceremony of di 2022 Fifa World Cup for Qatar. Di member of di South Korean boy band group perform di official World Cup song Dreamers as e thrill di audience for di Al Bayt stadium. Jung Kook perform di official World Cup song Dreamers wit Qatari singer Fahad Al-Kubaisi. Thousands of fans sing and dance to di song wey Qatar use welcome 31 kontris come di World Cup. Di 25-year-old bin release di track for Fifa World Cup 2022 wey im title Dreamers on di opening day of di Qatar World Cup. Di song highlight optimism wey every World Cup dey bring every four years. “Look who we be, we be di dreamers, we go make am happun cause we believe am,” na how di song take start. World Cups dey always get landmark tracks like Wavin Flag and Waka Waka for 2010 to di Cup of Life for 1998 and dis track go be anoda addition to di collection. Di World Cup opening ceremony take place on November 20, ahead of di opening Group A match between host Qatar and Ecuador. Di opening ceremony start proper wit Hollywood actor Morgan Freeman wey be di official narrator for di ceremony. E tok about how di World Cup dey open to di whole world and about di ""emotions wey connect us all now"". Pipo bin clap wen Sheikh Hamad bin Khalifa Al Thani show for one big screen. Di sheikh na di man wey hold di World Cup trophy for Switzerland wen Qatar win di bid to hold di tournament for 2010. Some Ardah dancers wit swords also perform for di opening ceremony. Some pipo wey no wear cloth also dey hit di drums. Pipo dance wit all di World Cup flags. Qatar 2022 mascot na giant wey dem call La'eeb - La’eeb, na Arabic word wey mean super-skilled player. E belong to one parallel mascot-verse wey dey indescribable. La’eeb bin encourage everyone to believe in themselves." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c3g50n22gego +sports Manuel Pellegrini: West Ham sack manager afta Leicester waya dem for house "West Ham don sack manager Manuel Pellegrini afta dem chop 2-1 home defeat at di hand of Leicester City - dia number 9 loss for di last 12 matches. Di Hammers last defeat on Saturday don carri dem down to 17th position for di relegation zone of Premier League. Former West Ham boss David Moyes dey among di candidates wey dem dey consider to replace Pellegrini. ""Na wit great disappointment we don decide to do dis,"" tok joint-chairman David Sullivan. ""E don dey clear say we need change in order to bring di club back on track to wetin we desire for dis season. ""We feel say e dey necessary to act now in order to give di new manager time to try and achieve that goal."" Pellegrini lose im West Ham job 18 months afta dem employ am for 2018 on three-year deal, and dem tell am about im sack small time afta e do post-match interview finish on Saturday. Na within two hours of losing to Leicester na im West Ham make di announcement." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50937837 +entertainment Kiddwaya and Kaisha video: BBNaija ex-housemate deny ‘kissing’ allegation as she apologise for her carelessness "Former Big Brother Naija reality TV Star, kaisha don respond to accuse say she bin 'kiss' her former housemate, Kiddwaya. For inside series of tweet wey she post on Sunday morning, Kaisha dey shocked as pipo accuse her of kissing Kiddwaya. Her reaction dey come afta one video of herself and Kidd for one party on Saturday night as dem dey close and dey joke around bin go viral. Di fact say di video cut off at a point wen dem bin dey so close bin add fuel to di rumours. Some pipo for social media bin accuse Kaisha of trying to steal her 'friend' boyfriend. But di reality TV Star tweet say ""How?"", I bin drink too much for Praise birthday party last night and I no remember kissing Kid, so wia dis tori dey come from?"". She add say di ritual of Kiddwaya pouring drinks for dia mouth no dey new and dem all sabi how playful im be. ""Kidd na like brother to me and I neva imagine say I go ever kiss am. Na my fault say I dey careless last night, I drink too much."" Kaisha also post di complete video of wetin really happun between her and Kiddwaya to clear di air on accuse say she kiss her former housemates. She admit say na her carelessness push di negative narrative between herself and Kidd and she apologise. Kiddwaya also tweet as di tori bin dey trend say ""False story. Goodnight.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-55876777 +politics Osun election 2022: All you need sabi about di governorship poll Di pipo of Osun State for southwest Nigeria go decide dia own fate on 16 July, 2022 wen dem go elect di govnor of di state. Di incumbent Govnor Gboyega Oyetola na im dey represent di All Progressives Congress (APC) for di election and im major opponent na Ademola Adeleke of di Peoples Democratic Party, PDP. Some of di oda govnorship candidates for di election na Yusuff Lasun of Labour Party, Akin Ogunbiyi of Accord Party, and Omigbodun Akinrinola of di Social Democratic Party. See di full list of candidates wey di Independent National Electoral Commission release. Di Resident Electoral Commissioner of di Independent National Electoral Commission (INEC) for Osun state, Professor Ganiy Raji say dem don fully ready for di govorship election. Professor Raji yarn dis one wen e follow BBC Pidgin tok for di commission office wey dey Osogbo, di state capital hours before dem begin dey share di sensitive materials wey dem go use for di election. Di REC tok say dem ready to hand over any pesin wey dem see say dey involve for any kain election wuu-wuru to di security agencies to ensure say wetin happun for Ekiti State govnorship election of 18 June, 2022, wia some political parties and some voters bin engage in vote-buying according to di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) wey make some arrests, no happun for Osun State own. Na fifteen candidates dey battle for di govnorship seat of Osun and all of dem na male. Out of di fifteen deputy govnorship candidates, only six of dem be female. Di fact say no female govnorship candidate for di Osun election further show say na men dominate di Nigerian political space and female representation still dey low despite call for more women to join politics and be part of di affairs of nation building. Since di creation of di state, no woman don become elected govnor. Di Osun State govnorship election fit big pass di recently concluded one for Ekiti State wey see Biodun Oyebanji of di All Progressives Congress (APC) win becos of di population and if more pipo come out to vote. Oyebanji defeat im closest rival Segun Oni of di Social Democratic Party (SDP) for di June 18 election as Bisi Kolawole of di Peoples Democratic Party (PDP) carri third. But only 360,753 pipo out of di total 988,923 registered voters come out to vote and dis na just 36.5% voter turnout. While Ekiti State get just 16 local goment areas, Osun State get 30 local goment areas. Wetin e mean be say INEC go need to double dia effort for di Osun election to record success wey go show say dem dey fully prepared for di 2023 general elections. Sake of say dis na di last election for INEC hand before di general elections for 2023, di outcome of di election go show weda INEC dey prepared for di big election or not. Di last govnorship election wey happun for September 23, 2018, see Gboyega Oyetola as di winner. Although na Ademola Adeleke win di first round of di election, di Independent National Electoral Commission (INEC) declare di poll inconclusive sake of say di margin wey im take win dey less dan di number of votes wey dem cancel. For di first round of di election, Adeleke of di Peoples Democratic Party (PDP) score 254,698 votes, while Oyetola of di All Progressives Congress (APC) score 254,345 votes. Iyiola Omisore of Social Democratic Party (SDP) score 128,049 votes, Adeoti Moshood Olalekan of Action Democratic Party (ADP) score 49,744 votes, while Fatai Akinade Akinbade of African Democratic Congress (ADC) score 7,681. So na just 353 votes Adeleke take beat Oyetola and INEC bin cancel 3,498 votes for some polling units. Section 153 of di Electoral Act tok say Inec go need to conduct a rerun if di margin of victory for election dey lower dan di number of voters for units wia dem cancel elections. So a rerun need to hold for areas wia dem cancel elections. INEC conduct di rerun between di two top candidates on September 27 2018, and by di time dem collate all di previous and current results, Oyetola score 255,505 votes, while Adeleke score 255,023. So at di end of di day, Oyetola use 482 votes pass Ademola and INEC declare am as winner of di election. Osun govnorship election timetable change sake of di legal battle wey follow di 2007 gubernatorial election for di state. One Court of Appeal for Benin overturn di electoral victory of Olagunsoye Oyinlola and declare Ogbeni Rauf Aregbesola as di rightful winner of di election afta three years of court case. E remain only one year for Oyinlola to complete im second tenure before court overturn im electoral victory. So Aregbesola kon begin im own first tenure as govnor in 2010 and end am in 2014. Im win re-election for 2014 and lead di state till 2018. Di last election for di state na in 2018 wey di current Govnor Gboyega Oyetola win as im defeat Ademola Adeleke of di Peoples Democratic Party (PDP). Di election go be di seventh gubernatorial election for di state. Na di military regime of Ibrahim Babangida create Osun State from di old Oyo State for August 27, 1991. Isiaka Adeleke, broda of di PDP govnorship candidate, become di govnor of di state for January 1992 till November 1993 wen di military junta of Babangida dissolve all political offices afta im annul di June 12 presidential election. Di electoral system na modified two-round system, wey mean say before candidate fit dey declared as winner, im need to receive di plurality of di votes and ova 25% of di votes for at least two-thirds of di state local goment areas. If any candidate no get to dis level, dem go hold anoda round of election between di top candidates. For di second round, any candidate wey receive a plurality of votes for di highest number of local goment areas na im win di election. Di tenure of Gboyega Oyetola go come to an end for November 2022 and di winner of di July 16 govnorship election go begin a new goment. Five out of di 15 govnorship candidates meet during di debate wey BBC Yoruba organise to discuss wetin dem go do for Osun State if dem win di election. Di candidates wey attend di debate na Govnor Gboyega Oyetola of di All Progressives Congress (APC) and Ademola Adeleke of di Peoples Democratic Party. Odas na Yusuff Lasun of di Labour Party (LP), Akin Ogunbiyi of Accord Party (AP), and Omigbodun Akinrinola of Social Democratic Party (SDP).Oyetola say im dey plan way to reinforce di state security system and empower di police force if im enta to be govor again. Adeleke wey bin don first contest election for 2018, say di reason why im dey recontest to become govnor for Osun na sake of di bad state of roads, hospitals, agriculture for di state. Lasun say im wan focus on reforming education sector for Osun state. On im own part, Ogunbiyi say im dey plan to focus on bringing businesses wey  go bring investments come di state. Akinrinola wan focus on reviving trade and investment for Osun State if im become govnor. https://www.bbc.com/pidgin/tori-62160612 +entertainment Shakira don join oda stars wey sell di rights to dia songs - See di reason why "Shakira don become di latest artist to sell di rights to her music for multi-million dollar sum. All her 145 songs, including Hips Don't Lie, Whenever, Wherever and She Wolf, dey included for di deal. Di songs don make her di best-selling female Latin artist of all time, wit 80 million records she don sell worldwide. She strike di deal wit di Hipgnosis Song Fund, wey recently buy Blondie and Neil Young's music. Hipgnosis company no disclose di financial details of di deal, but e dey always pay di equivalent of 15 years' royalties up front. Wit di tax money dem don already pay, many of di artists dey always waka wit ""about 25 years worth of money at once, di owner of di company, Merck Mercuriadis, tell BBC last year. Dis dey provide di artists wit immediate financial security, while Hipgnosis - wey go later get di songs go dey hope to profit as e go dey plan to make new profit streams for di music through film and TV licensing, merchandise, cover versions and performance royalties. Hipgnosis don dey spend billion of dollars for some years now as e dey buy di rights to music from artists like Nile Rodgers, Blondie, Barry Manilow, Chrissie Hynde and Fleetwood Mac's Lindsey Buckingham. Shakira na one of di most successful singer - songwriters of di last 25 years. Since she release her first album for 1991, at di age of 13, she don sell more dan 80 million records, don win three Grammy Awards and 12 Latin Grammy Awards. Over 13 million fans buy her first English-language album, Laundry Service for 2001. Her hit singles wey include Whenever, Wherever, Underneath Your Clothes, Hips Don't Lie and the 2010 Fifa World Cup song Waka Waka (This Time For Africa), top di charts for 15 kontris. Di star most recent album, El Dorado, dey certified diamond for di US. She be one of di only three female artists to get two videos wey pass two billion views on YouTube. And her latest single, Girl Like Me, bin catch fire for one viral dance craze on Tik Tok. Last year, she show for di Super Bowl half-time show alongside Jennifer Lopez, wey give her song catalogue anoda ginger and increase di value to investors. ""She be superb creator wey don create big success in streaming her songs pass most of her colleagues,"" Mercuriadis tok inside statement. ""Dis na di result of her being a determined force of nature and don write songs wey di world like well-well."" Financial security na di obvious reason. Rather dan to dey gamble say dia songs go continue earn royalties, for di next 25 years, singers like Shakira get big money up-front. Wetin Hipgnosis dey tell musicians na say dem no be traditional publisher, wey go dey exploit di rights of a composition, but dem be ""song management company"" wey go ensure legacy of artist by careful stewardship of dia music. After dem buy 50% take in Neil Young catalogue, for example, Mercuriadis promise say di singer classic track Heart of Gold no go ever dey burger commercial. Hipgnosis no be di only company for di game. Earlier dis week, investment company KKR (Kohlberg Kravis Roberts) buy di rights to 500 songs wey Ryan Tedder - write including tracks like Ed Sheeran's Happier, Camila Cabello's Into It and di Jonas Brothers' Sucker. Bob Dylan recently hand over im 600-song back catalogue to Universal Music, in a deal wey according to report worth hundreds of millions of dollars. And the US-based Primary Wave don dey buy up di rights to music by Stevie Nicks, Leon Russell, Leo Sayer and soft-rock duo Air Supply. For Shakira, another reason wey she fit dey sell fit be di €14.5m (£13m) tax bill Spanish goment recently sama her. For inside statement, di Colombian say Hipgnosis go be ""great home"" for her music, and to her love for songwriting. ""Being a songwriter na accomplishment wey I consider equal to and perhaps even greater dan being a singer and an artist, "" she tok. ""At eight years old - long before I begin sing - I dey write songs to make sense of di world. Each song na a reflection of di person I be dat time wen I write am, but once one song don come out for di world, E no belong to only me again but to pipo wey dey appreciate am as well. ""I dey humbled say song writing don give me di privilege of communicating wit others, of being a part of something wey dey bigger pass me.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-55650261 +entertainment Stingy Men Association of Nigeria: Social media trend, app and how pipo dey relate wit SMAN Di Stingy Men Association trend don really catch fire dis week for Nigeria and even Ghana, afta some ogbonge celebs chook mouth for di mata. Now social media influencers for Nigeria and many oda pipo dey use videos and fotos to spread di association message. Di Stingy Men Association of Nigeria na new men movement and social media trend, wey be like something to create fun amongst social media users for di kontri. For inside di form wey dem create, di association tok say dia motto na to stop to give money by any means of financial exploitation to di oda gender. Dem promise not to dey financially committed to women wey dem no dey in relationship wit. Singer and producer, Don Jazzy tweet im own ID card and write say 'Registration complete'. Inside di tweet wey now don get more than 11,000 retweet, Don Jazzy write for im ID card say e be Head of di union. More Nigerian celebs like Paul Okoye of former Psquare, Mr Eazi and some odas don dey use di trend to catch cruise. Even female celeb like Toke Makinwa also catch cruise for dis mata too. See comedy skit wey Debo Macaroni aka mrmacroni do ontop di Stingy Men Association trend. Senator Dino Maleye dance to di Association song. Some sef do video of dia meeting and di association laws. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55672731 +sports Reactions as Arsenal send support to Nigerians afta #EndSARS Lekki shooting gbege "London club Arsenal FC, wey get millions of fans for Nigeria, don comot wit support for Nigerians, following di recent protest against police brutality for di kontri. Arsenal tweet from dia official Twitter account: 'Nigeria, we see you, we hear you, we feel you."" Dis na di first show of support from any of di big football clubs wey popular wit fans from di West African kontri. Dis message dey come just days afta di Lekki shootings wia soldiers open fire ontop unarmed protesters for Lagos on 20 October. Arsenal popularity grow during di early 2000s afta di club sign ogbonge Super Eagle player like Nwankwo Kanu and promote JayJay Okocha nephew Alex Iwobi to di senior team for 2015. Di club on dia message wey dem write wit white text ontop black background, encourage Nigerians say dem see all di video and dem no fit imagine di pain di citizens dey go through. ""Stay strong, stay safe"" na how dem take close di message. One Twitter use @tifefabunmi praise Arsenal say im don award dem di ""best team for di world, afta Chelsea"". Some even begin prophesy say dem go finally win Champions League competition. But odas say wetin Arsenal do dey bias because e not too tey wey di club condemn dia own player wey show support for one group of Muslims for China. Normally international clubs no dey chook mouth for anything wey resemble politics mata in oda kontris." https://www.bbc.com/pidgin/sport-54673996 +health Trump: Dexamethasone, remdesivir, Regeneron, wetin be dis 'Covid' drugs doctors use for US president coronavirus treatment? "US President Donald Trump don return back to White House to continue im treatment for coronavirus after three-night wey e stay for hospital. Di president remove im mask for di balcony of di White House, wia different staff and aides don bin test positive for di virus for recent days. E later tweet say; ""Feeling really good. Don't be afraid of Covid. Don't let it dominate your life."" Plenti pipo still dey ask questions on top how serious Presido Trump covid-19 sickness dey and how im treatment dey like. Normally, Treatments fall into two camps - those wey dey directly attack di virus and dey more likely to dey useful for di first phase and drugs to calm di immune system wey dey more likely to work for di second. Since President Trump test positive for coronavirus, e don dey receive some number of different drugs, according to wetin im doctors reveal. So which drugs dem dey use and wetin e tell us about Trump condition? Dis steroid dey save lives by calming di immune system, but dem need to use am for di right time. Give am too early and di drug fit make tins worse by hindering di body ability to fight off di virus. Dis no be di kind of drug wey you go usually give pesin wey dey di ""mild"" stage of di disease. One trial of di drug wey take place for UK show say di benefit dey come in for di point wey pesin need oxygen - wey Presido Trump receive briefly. World Health Organization advise di using of di steroid for ""severe and critical"" cases. Dis na combination of antibodies, wey dis company Regeneron dey make, and e dey mimic di human being immune response. Di antibodies physically stick to di coronavirus so dat e no fit get inside di body cells and dey make di virus more ""visible"" to di rest of di immune system. Dem first develop dis antiviral drug as treatment for Ebola. E dey work by confusing di virus as e look chemically similar to some di raw materials di virus need to replicate. Dis dey scata di virus ability to make thousands of copies of itself. Clinical trials don show say di drug dey cut di duration of symptoms from 15 days down to 11. But no evidence don show weda dem don save live with remdesivir. President Trump doctors tok say e also dey take zinc, vitamin D, famotidine, Melatonin and Aspirin. E no dey clear if any of these na purposely for Covid 19. Zinc na mineral wey get role for di immune system, but no evidence on show say dis kain supplements dey improve pipo ability to fight di virus. Vitamin D dey known as di sunshine vitamin as e dem form for di skin as response to sunlight. E also get role to play for healthy immune system, but again no evidence don show say taking supplements dey help against Covid 19. Famotidine dey decrease stomach acid production and dem dey use am for pipo with stomach ulcers or reflux. E get one small study wey suggest say e fit help, but dem consider di quality low and researchers don call for more research. Melatonin na hormone wey di body dey make in di evening and e dey help us sleep. Dem dey sometimes give am as treatment for insomnia. Aspirin na pain killer and blood thinner wey dem dey use take reduce di risk of blood clots. Covid patients dey experience unusual blood clotting and e fit also calm inflammation inside di body. Dem don do trials for aspirin in Covid, but no evidence don show if e dey useful." https://www.bbc.com/pidgin/world-54431213 +entertainment Ed Sheeran and Cherry Seaborn announce birth of dia daughter Lyra Antarctica – See oda celebs wey become parents dis coronavirus period "Ed Sheeran don announce today say im don get bouncing baby girl with im wife Chelsea Seaborn. E announce dis one for im social media handle on Tuesday say na one week ago dem born im pikin, Lyra Antartica Seaborn Sheeran. E come add say di mama and pikin dey do well. Dis year, despite di coronavirus palava, many celebrities announce di birth of dia pikin dem. See some of dem. Nigerian singer, Simi welcome her daughter, Adejare with husband Adekunle Gold wey dem born for 30 May. D couple wey bin do secret wedding last year first share di news say dem dey expect addition to dia family wen Simi drop ""Duduke"" wey shake di music world for May. Na for June dis year Nigerian actress, Regina Daniels announce di birth of her first pikin, bouncing baby boy, Munir Neji Ned Nwoko, with husband Ned Nwoko. She bin reveal say she get belle for May with photoshoot for inside social media. American singer, Katy Perry give birth to her first pikin, baby girl at di age of 35 wey she name Daisy Dove Bloom. Na her bobo, actor Orlando Bloom bin announce dis one for im social media on 27 August say dem dey lucky to give birth for peace even for dis coronavirus time. American musician, Joe Jonas and Sophie Turner welcome dia first pikin, a bouncing baby girl wey dem name Willa Jonas for July, 2020. Di two wey bin marry for June last year for lavish event for Paris, bin no really tok so much about dia pregnancy. Even as na only on statement dey give tori pipo on di state of dia pikin." https://www.bbc.com/pidgin/world-53975995 +entertainment Super Bowl half-time show: How did The Weeknd performance dey totori fans "One tin wey many pipo dey always look forward to evri year for di Super Bowl half-time na di musical performance. From Beyonce to Phil Collins to the Black Eyed Peas, Usher, di show na big sometin wit crowds. But dis year own dey different. Thousand of fans wey dem do like cardboard cut-outs watch di show wit social distancing for di Raymond James Stadium wey dey for Florida. Di city lights, di slot machines, and The Weeknd as e just siddon for im car. Di styel of im entrance be like im hero Michael Jackson 1993 halftime-show; and den im start im 2016 hit, ""Starboy."" E pack eight songs for 14 minutes, wit no guests features but e come get big large choir, live guitar band, and some violinists. Apart from some Michael Jackson-inspired dance moves, im just focus on di music before e come grab camera and den e disappear for backstage wit plenti lights and mirrors. As dnacers wey get bandage for face surround am, im perform Can't Feel My Face, before e show for di stadium wit firework for anoda version of I Feel It Coming. O boy, afta di performance na so fans and fellow celebrities full social media wit accolades for di Canadian singer wey im real name na Abel Tesfaye. Drake tok say di show na ""a big moment for di city"" for im Instagram story. Country star Keith Urban tok say e dey impressed, and actor Timothée Chalamet caption one small video for im Instagram story as: ""Legend! Legend!"" The Roots' Questlove dey part of pipo wey sabi say wetin The Weeknd do na throwback to Michael Jackson Super Bowl performance in 1993. And plenti reaction to di moment wen di star dey prepare to sing im 2018 hit Can't Feel My Face, as come pretend to dey rush make im dey stage before di track start. Na so pipo don turn am to meme." https://www.bbc.com/pidgin/world-55989271 +entertainment Peru: How Ed Sheeran reach out to Fireboy DML to record remix of global hit "Wen dem tell Fireboy DML to check im DMs, im bin need to dey convinced say Ed Sheeran message bin dey real. Ed bin don send di Nigerian singer note wia im say im be fan and want collaborate on remix of im Afrobeats hit, Peru. ""Im bin don listen to di song for weeks,"" Fireboy tell Radio 1 Newsbeat, from im studio for Lagos, Nigeria. ""Not only say im bin don hear di song, but im bin don already record verse for am too."" Di 25-year-old dey aware of critics wey say becos im feature big name on di track e go dilute di song origin. ""Pipo bin dey tok say Peru don already dey big. E already dey good enough without him,"" Fireboy tok. But im say di ""only tin"" on im mind when e involve Ed Sheeran wit di remix na how e go dey"" amazing for Afrobeats."" ""Na di selfless mind-set wey come wit being Afrobeats artist. Everitin you do na for di culture."" For di song, Ed sing a couple of lines for Yoruba, language wey millions of pipo across West Africa, especially south western Nigeria dey speak. ""Im do great,"" Fireboy wey im real name na Adedamola Adefolahan tok. Fast-forward, and now di Peru remix only dey behind We Don't Talk About Bruno, from Disney movie Encanto for di top of UK Official Singles Chart . ""E go dey amazing for di whole Afrobeats genre if e get to number one,"" im tok. Di remix wit Ed Sheeran drop late last year, but Peru bin don already become Fireboy biggest streaming hit to date and e spend four weeks for di top of di Official Afrobeats Chart. Anybody wey dey look for any hidden or deep meaning to di track go dey disappointed. As di song lyrics tell us say, Fireboy perform am spontaneously afta im arrive from Miami. Di singer wey dey signed to Olamide YBNL record label say im no overthink di song and record am as freestyle during studio session wey im no plan last July. ""I bin know say I get very beautiful, catchy song and wen you get catchy hook for Afrobeats, you literally don get hit already . Just before Christmas, Fireboy meet Ed Sheeran face to face for di first time to record di video for New York. ""Di atmosphere bin dey great,"" im tok. ""I don listen to am for more than 10years now and na im be di pesin wey make me love di acoustic guitar."" Fireboy don dey make music since im be pikin child but di ""spark"" only ignite wen bin dey second year for university. ""From dat point on I become blind to everitin else, including school and relationships. Music go give you blind devotion and obsession."" Wit di success of Peru, Fireboy say im no want get ""too many big dreams and aspirations."" ""Na like dat you go set yourself up for undue pressure."" But 2022 already look like busy year wit US and UK tours, im third album and festival appearances, wey im don hint say fit involve im new friend Ed. ""Stay tuned. We wan give di fans some special memories dis year.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-60187171 +health Coronavirus Tips: Face mask fit protect you from Covid-19? BBC Pidgin don launch 'Covid-19 in 60 seconds' wey be daily video on tins to know. Plenty pipo no need face mask like di one inside dis video except say you sick or dey take care of sick person wey dem dey suspect say get coronavirus. Coronavirus dey enter bodi through di mouth and nose. And pesin fit carry am give anoda by touching eyes, nose or mouth with our hands. E fit even be pesin wey dey inhale droplets directly for coronavirus carrier wey dey cough or sneeze. So, face mask fit help reduce di spread from pipo wey get di virus fortimes wey you no fit distance your sef well well. But e dey necessary if you neva catch di virus or if you dey take care of pesin wey dem suspect say e get di virus? Today topic: 'Face mask fit stop #Coronavirus?' Dis video go show una wetin to do. Producers: Olaronke Alo, Dan Ikpoyi, Grace Ekpu, Daniel Semeniworima https://www.bbc.com/pidgin/tori-52042721 +entertainment Katy Perry copy hit song from Christian rapper according to one court ruling "Court for US don rule say American singer Katy Perry, copy her 2013 hit song Dark Horse, from one Christian rap song. Katy bin give evidence during di trial wia she deny say she neva hear di 2009 song Joyful Noise by Flame before she record her own track. She even ask make dem allow her perform Dark Horse inside di court room wen her lawyers no fit play di song for jurors because of speaker wey bin get issues. But di jury rule against Katy on Monday. During di trial, Katy team bin describe di beat of di two songs as ""commonplace"". Dem argue say because of dat, Flame (im real name na Marcus Tyrone Gray) fit not claim copyright. ""Dem dey try claim right to basic building blocks of music, di alphabet of music wey suppose dey available to evribodi,"" Katy lawyer Christine Lepera tok during her closing arguments for court last week. But di lawyers wey dey represent Flame claim say Katy and her team bin ""copy one important part"" of im song, as dem dey wrap up di legal tok-tok wey bin start for 2014. ""Dem dey try push oga Gray go one corner as one kain gospel music style wey nobody dey ever visit,"" Gray lawyer Michael A. Kahn tok. Im also mention say Katy bin start her career as Christian artist. Di court find out say di six songwriters of Dark Horse also dey responsible, including rapper Juicy J. On Tuesday 30 July, di court go begin work on how much dem go pay Gray for damages. Katy bin release Dark Horse for 2013 inside her fourth album Prism and na one of her biggest hits. E don sell more dan 13 million copies worldwide and di video of di song na di first ever song wey female artist sing to reach one billion views on both YouTube and Vevo. Dem don watch di video more dan 2.6 billion time since dem release am for 2014." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49169046 +health Wetin be 'Stiff Person Syndrome' di neurological disorder Celine Dion reveal she get "Canadian musician, Celine Dion don cancel her concerts wey she get for 2023. Dis na afta she reveal for Instagram video wey she share say she dey suffer from one neurological disorder. She say, ""recently I don dey suffer from one neurological disorder wey dem dey call Stiff Person Syndrome"". Di Courage singer explain more say, ""we now no say na wetin dey cause all of di spasms wey I don dey get, unfortunately, di spasm dey affect, all aspects of my daily life. Sometimes e dey make am difficult wen I dey waka, and sometimes, e no dey allow me use my vocal cords to sing di way I dey used to"". She bin say e dey hard to comot with dis information as e mean say she no go dey ready to restart her tour for Europe for February. She say she dey work hard to build back strength and her ability to perform again, ""but I need to tok true, e don be struggle"", na wetin she tok. Celine Dion confess say, ""all I sabi na singing an na wetin I love to do di most."" ""I always give 100% wen I dey do my shows but my condition no dey allow me to give una dat right now"", she tok as she dey hold back tears. She bin tok say she bin no get choice on di mata but to concentrate on her health na why she tok come outside. She thank her fans for dia love and support for social media as she tok s with shaky voice sAY, ""I love you guys soo much, and I hope say I go fit see una real soon"". Celine Dion bin pause her career indefinitely wen her husband, René Angélil bin dey battle with cancer. She come back for 2015, only to disappear from stage again afta her husband and brother Daniel Dion bin die. For 2018, she return briefly to sing di soundtrack of Deadpool 2 wey star fellow Canadian, Ryan Reynolds. Howeva, na 2019 she come back to music with dii release of her album Courage. Di album bin feature stars like Sia, Sam Smith and David Guetta. SPS na very rare condition and no dey very well understood. Even Celine Dion reveal say ""e dey affect like one in one million pipo"". Di National Institute for Neurological Disorders say e dey cause ""fluctuating muscle rigidity for di trunk and limbs and increase sensitivity to tins like noise, touch, and emotional distress, wey fit cause muscle spasms"". ""Di disorder fir also cause abnormal posture, like hunch over and stiffness"". ""Pipo wey get SPS fit det too disabled to walk or move, and dem fit fear to comot house sake of say noise for road like, car horn fit ginger spasms and falls"". ""Most pipo wey get SPS dey fall well-well and because dem no get normal defensive reflexes, injuries fit dey very bad"". No cure don dey for SPS yet but dem fit treat am with anti-anxiety medicines and muscle relaxants. Dis drugs dey slow di way di disorder de take progress. Singer Celine Dion na ogbonge musician wey don dey sing for most of her life. Di tori be say she write her first song at di age of 12. So far for her career, She don release 27 studio albums as well as several sound tracks wey she don do for movies like, Beauty and the Beast, Deadpool 2 and Titanic. Di soundtrack she do for di 1997 Titanic, My Heart Will Go On bin even win Grammy Awards. For di course of her career, she don win nine Grammy nods as well as multiple Golden Globes, Academy and Billboard Awards among odas. Di first time di 56 year old supper star take break for her career na around 2001 wen she bin dey take care of her husband and manager Rene wen e bin get throat cancer. Na around dat time she born her first pikin. She bin marry René Angélil for December 17, 1994 and dem bin enjoy 22 years of marriage before im death for 2006. She bin get three pikin dem names na René-Charles Angélil, and twins for 2010 wey dem call Nelson and Eddy." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c881y79n31xo +sports Ghana vs Nigeria match: In fotos, Black stars of Ghana arrive Kumasi as Nigeria Super Eagles intensify training ahead of FIFA 2022 playoff Di Black Stars of Ghana don arrive Kumasi ahead of dia 2022 FIFA World Cup playoffs against Nigeria on Friday. Di players and dia officials meet fans and tori pipo on dia arrival for di venue. Foto of di team arrival wey di Ghana Football Association post for social media show first timers Denis Odoi, Montari Kamaheni, Elisha Owusu, and Dennis Korsah for di squad. Meanwhile, Super eagles squad for di match don almost complete wit twenty-one players for dia Abuja camp and di arrival of Nigeria top striker, Victor Osimhen. Ahead of di Fifa World Cup qualifier between Ghana and Nigeria, Super Eagles arrive di Moshood Abiola National Stadium for dia first training session. Nigeria National team coach Augustin Eguavoen don drop Super eagles first choice goalkeeper, Maduka Okoye sake of say e no well. Enyimba International goalkeeper, John Noble don get invitation to replace Okoye. Di last time dis two kontris meet, na for 2011 but games between di two go way back as 1950. Ghana and Nigeria don meet 56 times across all competitions. Di Black Stars don win 25 while di Super Eagles don win 12 and di oda19 games end for draw. Playing Ghana away from home never really favour Nigeria as dem don lose 16 times wenever dia West African rival host dem. Six end for draw. Na only one time Nigeria win out of di 23 times wey Ghana don host. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60840702 +sports List of players wey dey leave Man U, oda transfer tori English Premier League transfer window don officially open today. Wit dis, premier league clubs fit begin sign players. Some top clubs don already announce new signings wey go finalize from 1 July. Dat be wen di contract of some players go begin end. Di transfer window go officially close by 11pm (UK Time) on Thursday, 1 September. Scotland transfer window, like that of the Premier League, opened on Friday. English Football League clubs bin don get chance to sign players since dia final game of di season. Aston Villa don already finalise some of dia transfer business before di window open. Dem don sign Marseille midfielder Boubacar Kamara (free), Barcelona forward Philippe Coutinho (£17m), Sevilla defender Diego Carlos (reported £26m). And Roma keeper Robin Olsen (reported £3m). Meanwhile Villa defender Matt Targett don join Newcastle for £15m afta successful loan spell. Leeds don sign two players from Red Bull Salzburg Brenden Aaronson and Rasmus Kristensen. Liverpool don sign Fulham youngster Fabio Carvalho for £5m. Croatia winger Ivan Perisic and England goalkeeper Fraser Forster go join Tottenham Hotspur on free transfers. Manchester City don reach agreement to sign Norway striker Erling Haaland from Borussia Dortmund for £51.2m. Although dem neva agree on personal terms. Chelsea defender Antonio Rudiger go joining Real Madrid and Alexandre Lacazette don leave Arsenal for Lyon - both comot as free agents. On Friday Manchester United release list of 11 players wey dey leave di club at di end of di month. Dem also release list of players wey dem go retain. Di players na D’Mani Mellor, Edinson Cavani, Reece Devine, Lee Grant, Jesse Lingard, and Juan Mata. Odas na Nemanja Matić, Paul McShane, Paul Pogba, Connor Stanley and Paul Woolston. Di club new coach Erik ten Hag get approval to rebuild di team for Old Trafford. Apart from Frenkie De Jong United neva begin tok about di players wey dem wan buy https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0vw8v8jvglo +sports Sierra Leone vs Nigeria live stream: Super Eagles play goalless draw wit Leone Stars for dia Afcon qualifier Nigeria play goalless draw wit Sierra Leone for dia African Cup of Nations qualifying match for di Siaka Stevens stadium wey happun on Tuesday for Freetown. Super Eagles coach Gernot Rohr make some changes to di team wey play draw wit di Leone Stars for Benin. Everton striker Kelechi Ihenacho replace Victor Osimhen wey get Injury. Dis match dey come four days afta Nigeria troway dia four goal lead against Sierra Leone to draw 4-4 for di Samuel Ogbemudia stadium for Benin City. Dis result mean say Nigeria get eight points from four matches ahead of Benin, Sierra Leone and Lesotho. Meanwhile Senegal don qualify for di tournament wey go happun for Cameroon. Confederation of African Football don move di 2021 Africa Cup of Nations to January 2022 sake of coronavirus pandemic. Nigeria coach Gernot Rohr keep faith wit di goalkeeper Okoye wey chop four goals against Sierra Leone for Benin but make changes upfront. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54977382 +sports Nigeria collect wotowoto for Portugal hand Portugal dey go Qatar 2022 Fifa World Cup wit plenty confidence afta thrashing Nigeria 4-0. Two goals from Bruno Fernandes and one each from Ramos and Mario give di Selecia dia well-deserved victory. Nigeria bin get chance to enta di game back for di 78th minute with a penalty kick - but Emmanuel Dennis miss am. Di Super Eagles bin no play well for di first half. Na for di second half dem find dia groove wit di substitution of some players. Thursday night display of di Super Ealges summarise di poor run throughout dis year. Dem don lose five of dia matches dis year - both comeptitev and non-competitive. Dis na di first time Portugal dey play Nigeria and dem go happy wit dia first experience. FULL TIME Portugal 4-0 Nigeria Second Half 90mins: Two minutes of time added on for Portuguese capital. 88mins: Dis na Nigeria almost get cause comedy of an own goal. Uzoho wey bin dey slow try stop di call from crossing di line. 84mins: GOAL! Portugal 4-0 Nigeria - Joao Mário make am four! 83mins: GOAL. Ramos score on im debut for Portugal 78mins: PENALTY for Nigeria. Emmanuel Dennis miss di penalty 78mins: Corner for Portugal. Dem lose di ball and Nigeria catch dem on counter. 76mins: Substitution for Portugal. Horta enta for Octavio 75mins: Anoda missed chance by Jao Felix. Im shot go off wide 73mins: MISSED CHANCE. Uzoho save Jao Felix shot. 72mins: MISSED CHANCE. Patricio save solo shot fromChukwueze. Di ball go corner 71mins: Etebolose di ball afta e spend too much time. 69mins: Substitution for Nigeria. Etebo enta for Joe Aribo 68mins: Fould for Nigeria. No card for di match. 66mins: Substitution for Portugal. Ramos enta for Silva. Na di first time Ramos dey play for National team 62mins: Free kick for Super Eagles. Mario bring down Simon on di edge. Simon take di free kick but Portugal goalkeeper save am. 61mins: Throwing for Nigeria. Moses Simon dey show effort from di left. 60mins: From Diogo Dalot to Vitinha, Jao Felixm Portugal attempy yo break Nigeria defence again. Troost-Ekong block di last pass. 59mins: Substitution. Onuachu enta for Murphy 57mins: Easy catch for Uzoho. Silva bin wan give through pass from di left. 55mins: Calvin Bassey det get tough time to move around as im like 53mins: Nigeria don dey impressive so far since di second half start unlike wetin dem play for di first part of di game. 51mins: Ramos and Jao Felix dey control Portugal play for midfield. 49mins: Antonio Silva block Iwobe pass to Chukwueze. Super Egles bin try move on a counter. 46mins: Super Eagles dey try find dia grooove early in di second half 45mins: Substitution for Nigeria. Onyeka enta for Ndidi Chukwueze enta for Lookman 45mins: Substitution for Portugal. Pepe, Vitinha, João Mário and Raphael Guerreiro enta for Rúben Dias, Nuno Mendes, Bernardo Silva and Bruno Fernandes. HALF TIME Portugal 2-0 Nigeria 45mins: Bruno Fernandes almost score wit a lovely through ball by Joao Félix. 44mins: Nigeria pin Portugal back. This Naija team no go at all. 40mins: Simon take on im man on di left, before slipping di ball inside to Aribo. 38mins: Portugal dey in total and utter control. 35mins: Bruno score di penalty! Portugal 2-0 Nigeria! PENALTY! Ref blow penalty kick for Portugal afta Super Eagles defender foul inside box 18. 33mins: Ndidi bring Otávio down some 40 yards out from goal, and Portugal get opportunity to deliver dead ball into di Nigeria box. 31mins: Portugal goalkeeper Rui Patrício dey touch ball for di first time. Portugal 1-0 Nigeria 27mins: Portugal do neat short-corner routine wey end up wit Mendes cutting di ball back to Carvalho. Portugal 0-0 Nigeria 26mins: Iwobi pass give Aribo, e no fit take di ball do better tin. 23mins: For di first time Nigeria manage to comot for dia own half 18mins: Portugal get 70% possession. All di game dey happun inside do half of di Super Eagles. 16mins: Bernardo Silva whip low ball into Super Eagles area but e too far. 9mins: GOAL! Bruno Fernandes score for Portugal. Portugal 1-0 Nigeria ​​​​​​​6mins: Bright Osayi-Samuel dey also m,ake im first appearance for Super Eagles on di right back. 4mins: Portugal dey control di ball inside José Alvalade. Mendes bring di ball forward down di left, before e play am to André Silva. 2mins: Nigeria immediately win corner. Simon take am but dem no handle am well. 1min: Portugal 19-year-old centre-back António Silva dey make im debut for di Seleção KICK OFF: Firt Half Portugal: Patrício, Dalot, Dias, António Silva, Mendes, Otávio, Bruno Fernandes, Carvalho, João Félix, André Silva, Bernardo Silva​​​​​​​. Nigeria: Uzoho, Osayi-Samuel, Akpoguma, Troost-Ekong, Bassey, Ndidi, Lookman, Aribo, Iwobi, Simon, Moffi. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4n67605pk1o +sports Norwich City vs Man City: Premier League champions lose 3-2 to Canaries Norwich City score three goals to beat Manchester City 3-2 to end di blues unbeaten league run. Goals from Norwich top scorer Teemu Pukki, Todd Cantwell and Kenny McLean na im help di newly promoted side beat di reigning league champions. Even though Sergio Aguero and Rodri score two goals for City, e prove to be consolation as Norwich make sure say na dem carry di day. Before di game, 11 Norwich players suffer injury wey make dia coach Daniel Farke use some new players wey never play dis season. Di last time wey Manchester City lose for Premier League na for January 29, 2019 wen Newcastle bin beat dem 2-1. Dem been don go 19 games without defeat before Norwich come spoil dat record. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49702458 +entertainment Bae U: Skit maker IsBae U react to sex for skit accuse wit receipt """I no go blame anybody for wetin dey happun but I go blame myself"", na so comedian and skit maker Bae U respond allegations wey say im dey demand sex from women for skit roles. For inside video wey im post on im social media page, Bae-u wey im real name na Adebayo Ridwan say im dey heartbroken and weak afta di allegations come out say e dey ask girls for sex before dem go feature for inside im comedy skit. Bae U become trending topic for Nigeria social media space on Sunday night, 30, January 2022, afta one local blogger share multiple screenshots of im social media conversations wit ladies. Di screenshots show am dey ask ladies wey show interests to feature for im comedy skits to come sleepover for im place for sexual activities. Di blogger post stories of di ladies wit screenshots from di direct messages wey dem say im get wit dem. ""I don receive every stone wey dem throw me, I be human and I no go blame anybody"", di skit maker respond ""Na girl wey live for my street on di mainland a very long time ago, she come around and we bin sex"", e admit. but im no tok whether di relationship get anytin to do wit role for im skit. ""I pray and hope I fit go back to making more funny skit to pipo wey feel say I dey funny. I go make everyone wey dey down dey happy. ""I just wan make skit, make videos, create content"", Bae U add . Im also share screenshot of wetin im describe as blackmail wia one of di girl dey ask am for money and promise to release im videos. Meanwhile im fans don enta social media to react Adebayo Ridwan wey dey known as Bae U dey popular mostly on Instagram sake of comedy skits wey im dey do. Bae U say im begin make comedy skit sake of depression. E tok dis one for inside interview wit ''TheKreativo'' For di interview wey dem tag true life story, Bae U say im bin dey confused and e bin need help. ""I bin need something wey go ginger me and I tell God make im show me a way because I bin no sabi wetin I dey do."" E tok say im thank God say im later find sometin wey bring am to life, wey be im skit. Im say na im single handedly take care of imsef. Bae U comedy get over 600 thousand following only on Instagram. Di skit maker dey also act and direct feem." https://www.bbc.com/pidgin/media-60195096 +politics Imo state news: Hope Uzodinma, police launch ‘operation search and flush’ "South east Nigeria don calm compared to wetin don happen in di last 7 months for di region. For dat period, Police suffer attacks from gunmen for inside di mainly Igbo speaking region of eastern Nigeria, according to different confam tori wey BBC Pidgin don torchlight. Di jaguda boys also target federal property including office of Independent National Electoral Commission, INEC, prison facilities and odas. To address di situation for South eastern Nigeria President Muhammadu Buhari for im interview wit Arise Television say di agitation of Indigenous People of Biafra (Ipob) na ""dot in a circle"" wey no fit exist anywhere. ""Di ones for di south east we know dem, di ones for di north east we know dem,"" President Buhari tok. E no tey afta President Buhari make di pronouncement wen security agencies launch operations for south-eastern Nigeria. Di first one 'Operation Restore Peace' wey Inspector-General of police launch for di region - di operation don yield results wit di arrest of plenty suspected members of di gunmenwey dey disturb di region. Now, di police togeda wit di state goment don launch 'operation search and flush'. Recently Inspector General of Police Usman Alkali flag off of Operation Search and Flush for di state afta di state goment donate vehicles and oda logistic assistance to assist police. Di Police IG Alkali wey commission di operational base of of 'Operation Search can Flush' say im dey happy say Govnor Hope Uzodinma dey committed to restore order for di state. ""'Operation Search and Flush' na to provide visibility policing for all communities for Imo state to avoid attack by jaguda pipo,"" police tell BBC pidgin. Michael Abattam, tot-tok pesin for Imo police say di operation dey in collaboration between police, Army, Civil Defence and oda security agencies wey dey for di state. According to Abattam, ""specifically dis operation na to provide visibility policing for communities. And di major role na to dey carry out steady patrol to ensure say pipo dey safe. ""Di operation go also enlighten our pipo about security. So we except say pipo go support us by offering information on major criminal activities wey dey happen. ""I never sabi wen di operation go end because e just deg start.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-57721460 +health Coronavirus: Ghana record en first COVID-19 recovery case "First COVID-19 patient recover for Ghana after de virus enter de country. De patient wey recover be one of de first cases wey de country around March 12. Ghana Health Service announce de recovery for dema covid-19 website on Thursday, March 26, 2020. Health officials say de COVID-19 patient after treatment dey test negative now. Ghana Health Service say so far 49 people dey respond to treatment, 1 person dey inside critical condition wey 3 people die so far. Meanwhile, Ghana Medical Association (GMA) dey call on govment make dem declare nationwide lockdown. Dem say de lockdown for affect everything except people who dey offer essential services. ""GMA be conscious of de threat and disturbing trend of community spread plus de inadequate capacity for de country health system to deal with increased COVID-19 infections."" ""President of Ghana for declare nationwide lockdown with de exception of essential services immediately"" GMA President, Dr Frank Ankobea sign for statement inside. So far de kontri don record 132 cases of coronavirus, 54 from regular surveillance from de country den 78 cases wey dem pick from travelers wey dey under mandatory quarantine." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51959717 +sports Blessing Oborududu win Nigeria first Tokyo 2020 Olympics medal Nigerian athlete Blessing Oborududu don make history as she become di first to win Olympic medal for wrestling for her kontri. Oborududu beat Battsetseg Soronzonbold from Mongolia for di semi-finals of di women's 68kg freestyle event to secure at least silver medal, di first for her kontri for di Tokyo Games. Di Commonwealth champion Oborududu go face top seed Tamyra Stock Mensah for Tuesday final, after di American World champion overpower Alla Cherkasova from Ukraine 10-4 for di first semi-final. Following her passage to di final, di 32-year-old Oborudud dey guaranteed to win silver, at least - di first wrestling medal for Nigeria history for di Olympics. Dis history making effort by Oborududu dey come one day afta Ghana boxer, Samuel Takyi also dey guaranteed to win im kontri first medal since 1992. Oborududu victory dey come at a time Nigerian contingent for dis year Olympics dey face mixed results. Earlier on Monday di kontri women basketball team crash out of di Olympics afta dem lose dia final group match to Japan. Di male basketball team also suffer di same fate on Saturday as dem too lose all three of dia group games. Also, news of medal hopeful Blessing Okagbare failed drugs test hit di kontri hard as oda athletes bin don chop disqualification from di tournament because dem no comply wit out-of-competition drug testing. Na im make dis news of Oborududu victory go sweet di heart of sports-loving Nigerians wey bin get high hopes before di tournament start. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58059457 +sports Wales vs Switzerland: Breel Embolo, Kieffer Moore goals see both side share points Wales and Switzerland begin dia Euro 2020 campaign wit 1-1 draw. Switzerland bin take di lead early for di second half as Breel Embolo nod in Shaqiri corner kick past Wales goalkeeper, Danny Ward. Despite say Switzerland control di game, Wales equalise for di 74th minute as dia striker Kieffer Moore guide Joe Morell cross into di net wit im head. Both teams try to find di winner late in di game but na Switzerland come di closest as VAR rule out Gavranovic goal for offside. Switzerland continue to dey press for di winning goal deep into added time but brilliant saves from Danny Ward deny dem di opportunity to get one. Di way di Swiss pressure dia opponents go make Wales even feel happy say dem get one point from di game, as dia next game go be against Turkey for Baku on Wednesday. After Turkey suffer 3-0 defeat to Italy for Friday tournament opener, Wales and Switzerland get one point each fro Group A afta Matchday one. Both teams go play again for Group A action on Wednesday, Wales go stay for Baku wia dem go take on Turkey, while Switzerland go travel to Rome to face Italy. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57455737 +sports Mike Tyson vs Roy Jones Jr. fight end in draw - See how e dey happun "Boxing legends Mike Tyson and Roy Jones Jr fight don end in draw. Di Former world champions Mike bin meet for one eight-round exhibition fight Saturday night for Staples Center in Los Angeles. Di fight na di main event of one six-fight PPV event. Dem don tok about di fight between the two legends wen dem bin dey active for boxing competitions but now e dey happun as exhibition. Round 8: Tyson bin win di last frame (maybe) and di official decision na draw. For about 30 seconds, e look like both boxers go go all out for di final round, but then reality set in. ""Not be battle of di ages, but a battle of di aged,"" di announcer tok. Tyson look like he fit go a couple more rounds, while Jones look like he s done a couple of rounds ago. Tyson enta wit some shots, but Jones get just one, maybe. Round 7: Jones open up and Tyson come back. Jones open dis round wit one punch, bouncing left and right off Tyson bodi Di offense no stop Tyson, he press forward wit big lefts and rights. So Jones open up again, run meet Tyson wit another round of punch. Round 6: Tyson go afta di K.O. a few times. Since dis na exhibition knockout no suppose dey, but Tyson throw a couple of punches midway through di round wey get some intent. Dem no just land for Jones bodi. Jones later land one clean shot near di end of di round. Round 5: Tyson begin open up. Tyson land one right hand to di Jones body early, and plenti hooks upstairs as di round progress. Jones still dey clinch, dey look to force Tyson to carry im weight, but Jones dey fade fast. Round 4: More of di same thing wey happun for di third round of di fight. Round 3: Jones smart plan. Jones lean on Tyson, walk am back, and make am tired. Tyson throway di heavier blow. Jones throw di faster punches. None of di fighter land many clean shots. Round 2: ""shake and bake."" Tyson open di second round rush into Jones, Jones quickly grab am to slow things down, just like di first round. Tyson land di biggest shot of di night 30 seconds into di round, a strong left to Jones face. Round 1: Action and clinching Tyson start fast, e dey weave, jab, hook, and miss. Jones start too — move, jab, and e dey miss. Eventually di two fighters gbab each oda, one of moment wey dey define di first round. Both fighters dey dia 50s, one of di reason why di fight bin gather plenti of interest and attention from fans. Mike Tyson and Roy Jones Jr. na absolute best fighters of dia generation. Tyson, 54, neva fight professionally since im lose to Kevin McBride in 2005. Jones, 51, neva get any ogbonge win since im defeat Jeff Lacy in 2009. Tyson na one of di most ferocious punchers for boxing history and Jones na pound-for-pound elite. Commission officials bin tok say di fight no be to showcase how di men fight in dia full effort but instead e go be""hard sparring"" to show off dia skills. Despite di overseeing body statements on di rules, Tyson and Jones bin promise say dem dey go all out in dia effort to score di victory." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55119676 +sports FA Cup final: 'Chelsea vs Leicester match prediction' for Wembley stadium "Chelsea go lock horns wit Leicester City for di 140th FA Cup final on Saturday. Wembley stadium go come alive wen eight-time winners Chelsea and Leicester play in front of around 21,000 fans. Dis na Chelsea 15th final, while for di Foxes dis na dia fifth- but which team go win di match na di big question be dat. For di final BBC football expert Mark Lawrenson dey compete against Radio 1Xtra DJ Ace, wey dey support FA Cup holders Arsenal. Arsenal bin beat Chelsea for last year final but dia defence end for January afta Southampton beat dem for fourth round. No replay for di FA Cup final. If di score dey level afta 90 minutes, den dem go play extra time. And if afta extra time no winning goal, dem go play penalty to decide di winner of di match. Chelsea midweek defeat to Arsenal open door small for teams wey dey below dem for di race for di top four. Dis na particularly because dem dey try to win di FA Cup dis weekend, onto say dia rivals dey play for Premier League. Di Blues bin make seven changes for di Gunners game. Many pipo feel say bin dey too much - even wit a game like dis next time. E backfire for dem because of di result dem get. Thomas Tuchel go pick im strongest team for dis match and I feel say dat go dey too much for Leicester - Mark Lawrenson tok. Di Foxes bin get good win for Old Trafford on Tuesday, but dat na against a weak Manchester United side. Lawrenson add. ""E go dey close but, from wetin I don see of Brendan Rodgers side, I no think say dem get enough in dem them to break Chelsea."" To get around 20,000 fans back inside Wembley go help. Di sports tori pesin tok. Im say e go especially help di team wey dey chase di game and need dia fans to ginger dem to come back. I dey stick wit Chelsea to win it. Dem go create more chances, and dem just need to take them. Lawro 'Chelsea vs Leicester match prediction' na 1-0. Ace 'Chelsea vs Leicester match prediction': Me I dey go wit Leicester, Ace predict. E add: ""I feel say Chelsea eye dey on different prize wit di Champions League final in a couple of weeks."" For Tuchel to come in and win di FA Cup straight away. Ace say im go really make im mark. But winning di Champions League go dey even bigger.Radio 1Xtra DJ add. DJ Ace predict 1-2 for di game." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57126126 +entertainment BBNaija season 6 housemates go experience Biggie early twist about 'wildcard' "Organisers of di Big Brother Naija reality TV show don introduce new twist for di beginning of season 6 of di show wey dem call ""Wildcards"". Dis dey come as di housemates don begin settle-in for di house as di show start proper. Wildcards na fake housemates Biggie plant inside di Shine Ya Eye House wey none of di contestants or audience sabi who dem be. Out of di 22 contestants, two of dem na fake housemates wey no dey there to compete for di grand prize or for anything. On Sunday, August 1st, housemates go dey tasked wit di job of finding out who di fake housemates be, if dem get am correctly, di wildcats go comot di house. But if dem fail to fish out di right wildcards, dem go remain for di game and go dey allowed to compete for di N90million grand prize. Anoda twist to di show na say if dem no evict di housemates on Sunday, dem go get power to nominate Head of House on Monday. Di wildcards go dey revealed for audience for special diary session wey go start by 3:00pm on Thursday. Di TV reality show wey go last for 10 weeks go follow di lives of di housemates as dem interact and compete wit each oda to win di grand prize of N90million worth of prizes, wey be di biggest reward for any reality show for di continent. Di host of di show, Ebuka Uchendu announce say di Head of House game go hold on Monday by 6pm. Dis Monday game go determine who go be di first HOH for di season out of di 22 contestants. Every Monday, housemates get opportunity to contest and play game wey go make dem win Head Of House. Anybodi wey win HOH game go get immunity from eviction for dat week. Before di Head Of House get opportunity to chose who im go like to be im deputy and both of dem go get immunity for one week and get access to stay for di HOH lounge" https://www.bbc.com/pidgin/tori-57967477 +politics APC 100million form: Nigeria ruling party put N100m price for presidential form "Nigeria ruling APC say those wey dey eye dia presidential ticket gatz hold 100 million for pocket. Na money wey pesin fit use build at least three houses inside modern day Nigeria na im APC set as fee to buy presidential form for 2023 election primaries. Nigeria ruling All Progressives Congress [APC] National Executive Committee [NEC] set di 100,000,000 naira fee on Tuesday afta dia meeting. Di cost dey unlike di main opposition Peoples Democratic party [PDP] wey dey sell dia presidential form for N40 million naira. E cause reaction among many Nigerians wey feel say di price too cost and e also make election dey expensive. However dis same presidential expression of interest and nomination form na free for women and pipo wit disabilities. While youths gatz pay half di price. APC NEC meeting hold for Abuja and na president Muhammadu Buhari chair di gathering. Di highest decision making organ of Nigeria ruling party reach agreement on different issues especially as e concern di 2023 general elections. Part of di outcome of di meeting na di time table for di activities wey go lead to di ""special convention of di party"". Then dem discuss di price of interest and nomination forms for all elective positions for di elections. Di APC say dem go begin sell nomination and expression of interest forms for various elective offices from Saturday April 23, 2022. Dis na according to document wey Sulaiman Arugungu, di National organizing secretary of di bring out. ""In accordance wit di provision of di Electoral Act and di timetable of di Independent national electoral commission (Inec) APC hereby release timetable. ""And schedule of activities for di conduct of di 2023 general elections,"" Argungu tok. APC say di primary election for governorship position go hold on 18 May, 2022. While state houses of assembly go hold on 20 May, 2022. Di ruling party house of representatives primary go hold for 22 May and 24 May for Senate primary. Di party go end di process on 30 May wen dem go hold convention for presidential primaries. ""Forms for female aspirants and pipo wey dey live wit disability na free."" APC add. ""Youth wey dey age 25 - 40 years get 50% discount to buy di nomination forms,"" Argungu tok. Di Nec meeting na di first wey di APC hold afta Abdulahi Adamu become national chairman. APC bin elect new party executives from dia National Convention wey dem hold for 26 March. Di meeting last up to four hours and leaders of di party attend di meeting. Vice President Yemi Osinbajo, Senate President Ahmad Lawan, Speaker Femi Gbajabiamila, di party national chairman, Abdullahi Adamu dey among di leaders wey attend meeting. Some of di oda decision wey di party reach for di meeting na; Di new Electoral act for Nigeria wey president Muhammadu Buhari recently sign give political parties three ways to select dia candidates for any election. Dem be direct primary, indirect primary or consensus candidate. Ahead of di 2023 general elections di ruling APC choose to use di indirect primaries. Di Indirect primaries na use of delegates to select candidate for election. Wetin dis one mean be say na only delegates from each state go vote who go be APC presidential candidate. Bola Tinubu, Yemi Osinbajo, Orji Uzor Kalu, Rotimi Amaechi and Yahaya Bello don already indicate interest to contest di presidential election under APC. Odas na Dave Umahi, Rochas Okorocha, Ken Nnamani and Chris Ngige don also announce dia interest." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61167341 +sports Real Madrid vs Man City highlight: Benzema penalty, Rodrygo two quick goals send Real Madrid to Champions League final Real Madrid and Liverpool go meet for dis season Champions League final afta di Spanish Champions come from behind to defeat Manchester City 3-1 for Bernabeau and win di tie 6-5 on aggregate. City, bin tink say dem go qualify for second consecutive all-English Champions League final, but Real comeback shock dem. Algerian, Riyad Mahrez 73rd minute strike bin look like e go dey enough to send City through but substitute Rodrygo score two late goals to send di tie into extra-time. Karim Benzema give Madrid di lead from di spot for di first half of extra-time afta Ruben Dias bin don foul di Frenchman inside di area. Real Madrid victory don see dem set up repeat of di 2018 Champions League final wen Real beat Liverpool 3-1. Dis defeat go pain Pep Guardiola and im boys as once again dem come close but yet dem dey far to win dia first Champions League trophy. For City and manager Pep Guardiola now, di Premier League title - go be dia only target as four matches remain. 106 mins - Real Madrid don restart play. Dis half na im go decide who go play Liverpool for di final on May 28. for Paris, France. 109 mins - Eder Militao don fall down and need attention from di doctors. E be like fatigue don hold am. Afta a while, di match don restart. 115 mins - Jesus Vallejo and Lucas Vazquez don come on for Militao and Vinicius Jnr. 118 mins - Raheem Sterling dey look to di referee to give am foul afta im fall near Madrid eighteen, Daniele Orsato, di referee wave play on. 120 mins - Grealish dribble im way into Real box come cross but Vazquez block di cross. Di corner reult to nothing as Courtois catch di loose cross. 120+1 mins - We don enta 3 minutes of stoppage time in extra-time. Full Time - Real Madrid don qualify to play Liverpool for dis season Champions League final. E finish Real Madrid 3-1 Man City (Real win 6-5 on aggregate). 91 mins - Man City don restart play from di centre circle. One fan don run enter pitch. 92 mins - Benzema try to side foot im shot in, Ederson spill am but later gada di ball. 93 mins - Penalty to Real Madrid! Ruben Dias slide in late to foul Benzema. 94 mins - Goal! Benzema score from di spot. Real Madrid 3-1 Man City. 99 mins Rodri don come off, Sterling don come on. 101 mins - Man City player Sterling receive yellow card for im tackle on Rodrygo. 104 mins - Dani Ceballos don replace Benzema. 105+2 mins - Fernandinho attempt from di back post no dey on target. Di midfielder feel sy im go reach Diaz header but Courtois punch redirect di ball na im make Fernandinho no connect well wit. Afta two minutes added time di ref don call for half-time in extra-time. Real Madrid 3-1 Man City. (Real lead 6-5 on aggregate) 46 mins - Real Madrid begin di second half and straight from di restart dem create chance wey Vinicius Jnr shoot wide. Carvajal cross di ball straight to di in-form forward wey fail to direct im shot goalwards. 50 mins - Gabriel Jesus dribble Real defenders to create small space for imsef dwn di flank. Im later shoot but Coutois catch am well. 52 mins - Vinicius dazzle im way into di away team eighteen, im pass give Modric wey no control di ball well. Im shot dey blocked but Ederson wey rush comot to catch am fail to do so, na Laporte boot di ball clear. 58 mins - Di fans inside di Santiago Bernabeau dey urge dia team on as dem need to score if dem wan send di game into extr-time. 61 mins - Vinicius go anoda of dos im runs as im try to outrun Walker, di 21-year-old try to find Benzema but Cancelo clear di ball. 63 mins City defender Kyle walker look like say im don injure. Di player receive medical attention but dey signal say im fit kontinu. 65 mins - Cavarjal foul De Bruyne, referee Daniele Orsato show am yellow card. 68 mins - Real Madrid coach Carlo Ancelotti don send on Rodrygo in place of Kroos. 70 mins - Walker don go down again and dey receive treatment. Di medics bring stretcher on but Walker limp off by imsef. 72 mins - Zinchenko and Gundogan don come on to replace Walker and De Bruyne. 73 mins - Riyad Mahrez don give City lead for Bernabeau. Bernado Silva lay good pass to di Algerian wey shoot am first time wit im left foot past Courtois. Real Madrid 0-1 Man City (3-5 on aggregate). 75 mins - Camavinga and Asension don replace Casemiro and Luka Modric. 78 mins - Substitution Jesus time for dis match don finish, Jack Grealish don enter. 82 mins - Benzema dribble Laporte come shoot on goal, Ederson save am. Di linesman flag don go up for offside, if to say Benzema score e for no count. 84 mins - Yellow card for Militao wey commit imsef into challenge to stop Grealish. 85 mins - Fernandinho don enter di match, im replace di goalscorer Mahrez. 86 mins - Cancelo curl one shot wit im right foot wey be like e go enta goal, Coourtois punch am well. 87 mins - Grealish run down Real goal come shoot shot wey Mendy clear off di line. Soon afterwards di Englishman get anoda chance to increase Man City lead but Courtois save im shot wit im legs. 89 mins - Rodrygo equalise 1-1. Di Brazilian tap in from close range cutback from Benzema. Real Madrid 1-1 Man City (4-5 on aggregate). 90+1 mins -Goallll. Rodrygo don head Madrid back into di game. Real Madrid 2-1 Man City (5-5 on aggregate). 90+3 mins - Foden try to play smart as City take one quick freekick just outside real area but di Englishman drag im shot wide. 90+5 mins - Yellow card for Valverde Di midfielder slide into Fernandinho. Tackle wey di ref consider as rash challenge. Full time - Na extra-time go decide dis one. 1 min - Manchester City don take di first kick of di match. 2 mins - From di kickoff Real Madrid win freekick close to Man City penalty area. City defenders clear di cross from Toni Kroos. 4 mins - Benzema head Carvajal cross over di bar. Dat na di first chance of di match but e no trouble Ederson for City goal. 8 mins - Modric and Laporte receive yellow card afta dem both involve in scuffle. 12 mins - Karim Benzema try im luck again wit first time shot from Valverde cutback. Di shot fly high and over. 16 mins - Kevin De Bruyne test Thibaut Courtois wit long range shot, di Belgian goalie save di shot. 18 mins - Vinicius Jnr receive loose ball inside Man City penalty area, chest am, come shoot di ball ova. Dat na good chance wey Real madrid no capitalise. 20 mins - Bernado Silva! Courtois deny di Portuguese wit point-blank save inside di box. 23 mins - Gabriel Jesus bend one shot just wide of Real Madrid goal. 27 mins - Kroos take one freekick wey bin threaten Ederson for City goal. Di shot take small deflection as e go out for corner. From di corner, Militao and Walker clash heads wey make di referee stop di match. Di City player dey alright to kontinu. 33 mins - Casemiro foul Phil Foden just near di centre circle. Look like di Brazilian dey in pain, Camavinga don dey warm up. 35 mins - Casemiro dey fit to kontinu. Meanwhile Vinicius want referee to show Walker card as di Brazilian claim say di City defender foul am. Di referee wave play on. 40 mins - Phil Foden shot lead to good save from Courtois wey dive low to punch di shot clear. 43 mins - Benzema tink say im don beat di offside trap as im race onto Modric through pass. Di Frenchman later shoot wide but di linesman flag later go up to signal for offside. 45 mins - We don enta two minutes added time before halftime and Man City don get corner. Real defenders head di ball clear go out for anoda corner wey dem still defend well. Half-time: Real Madrid 0-0 Man City (City lead 4-3 on aggregate) Man City XI: Ederson, Cancelo, Walker, Dias, Laporte, Rodri, Bernardo, De Bruyne, Mahrez, Foden, Jesus. Subs: Steffen, Carson, Ake, Sterling, Gundogan, Grealish, Zinchenko, Fernandinho, Egan-Riley, Palmer, McAtee, Lavia. Real Madrid XI: Courtois, Carvajal, Militao, Nacho, Mendy, Casemiro, Modric, Kroos, Valverde, Benzema, Vinicius. Subs: Lunin, Fuidias, Alaba, Vallejo, Asensio, Marcelo, Jovic, Vazquez, Ceballos, Rodrygo, Mariano, Camavinga. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61292480 +sports Chelsea vs Man City: Gabriel Jesus goal end Chelsea unbeaten start to Premier League season Gabriel Jesus second half goal help Manchester City defeat Chelsea 1-0 for dia own backyard. With two strikers on di pitch, Chelsea struggle to create chances as City end dia unbeaten start to di 2021/2022 Premier League season. Jesus deflected shot for di 53rd minute break di Chelsea defence wey don look solid dis season. Jesus almost score second goal wen Thiago Silva clear im effort off di line while Aymeric Laporte for score but im somehow slide e shot wide from inside di six-yard box. Mendy also produce two crucial saves from di excellent Jack Grealish. Before di game, Pep Guardiola bin don lose di last three matches wey im don play against Thomas Tuchel Chelsea including last season Champions League final. Now, Guardiola and im boys don get di better of Chelsea as dem dominate di Blues for Stamford Bridge. More dey come. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58692695 +sports Fifa Best award winners: Lewandowski beat Messi and Salah to win Best Fifa Men's Player of di Year award Bayern Munich striker Robert Lewandowski don win di 2021 Best Fifa Men's Player award. Di Poland striker beat Lionel Messi and Mohammed Salah to claim im second Fifa Best player award afta im win am for 2020. Lewandowski, wey dey 33-years bag di award afta im score 69 goals in all competitions last year. Barcelona player Alexia Putellas na she win di Best Fifa Women's Player of the Year. Chelsea goalkeeper Edouard Mendy don win Best Fifa Men's goalkeeper of di year award. Di Senegalese beat Gianluigi Donnarumma of Paris Saint-Germain and Manuel Nuer of Bayern Munich to win di award Gianluigi Buffon (2017), Thibaut Courtois (2018), Alisson (2019) and Manuel Neuer (2020) na di previous winners of dis award. Mendy help Chelsea win di Champions League for second time for im first season with di Blues. Im coach for Chelse, Thomas Tuchel na im win di Best Fifa coach award afta im lead Chelsea to champions league victory for 2021. Di German coach wey take ova Chelsea from Frank Lampard also win di Uefa Super cup wit di Blues. More dey come https://www.bbc.com/pidgin/world-59872142 +sports 2019 Ballon d'Or winner: How football stars, fans react as Lionel Messi win Barcelona star, Lionel Messi make history on Monday night as di first player to win di men Ballon d'Or awards for di sixth time. Messi AKA Di Greatest of all Time (GOAT) beat like 30 oda football stars wey dem shortlist for dis year award wey happun for Paris, France. Afta di win, Messi post thank you message for im facebook and Instagram to France Football plus Journalist wey vote for am to win di Ballon d'Or award. E say e for no fit win dis award without di help of im teammates from FC Barcelona and Argentina national team. 1.Lionel Messi 2.Virgil van Dijk 3.Cristiano Ronaldo 4.Sadio Mane Football stars and Fans don begin dey react and yan how dem feel about Messi. Livescore report say Juventus player, Giorgio Chiellini tell Skysport say Messi na fine Ballon d'Or winner, but dem rob Ronaldo last year. While some pipo for social media dey congratulate Messi, odas dey analyse di mata. Meanwhile, dem don officially name Juventus forward Cristiano Ronaldo di best player in Serie A last season, few hours afta Lionel Messi beat am to win di Ballon d'Or crown. https://www.bbc.com/pidgin/media-50640897 +politics Sunday Igboho: Omoyele Sowore allege plot to detain Sunday Adeyemo 12 aides for long "Di 12 aides of Sunday Igboho go dey free on bail latest on Tuesday, according to close sources. Nigeria secret police (DSS) bin charge dem to court last month. On 4 August, Justice Obiora Egwuatu of di Federal High Court, Abuja bin rule say di aides of di Yoruba-Nation activist fit receive bail, wit conditions. But five days later on Monday, some local tori pipo report say di DSS file remand application for di same court. Di move na to cancel di bail wey di court bin grant all 12 associates of Sunday Igboho, according to di report. ""We no dey aware of dat development. Di only development I sabi na say court grant dem bail. And we dey plan to get dem out today or tomorrow,"" Maxwell Adeleye, di toktok pesin to Prof. Akintoye bin tell di BBC. Professor Banji Akintoye na di leader of di umbrella body of Yoruba Self-Determination Groups, Ilana Omo Oodua [IOO]. IOO wey dey give legal support to Igboho. Igboho wey im real name na Sunday Adeyemo, currently dey detention for Benin Republic. Im dey face court mata dia wey di Nigerian goment carri come against am. Nigerian activist and former presidential candidate Omoyele Sowore, also post court documents. For di post im claim say lawyers to DSS bin use file di application on 9 August. Di BBC no fit independently confam dis court documents. Di DSS no immediately dey available when we reach dem for confamation." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58150467 +sports Tokyo 2020: Olympic Games organisers don 'agree to postpone' "Di organisers of di Tokyo 2020 Olympic Games, wey suppose start on 24 July, don agree to postpone di event for one year sake of di coronavirus. Japan's Prime Minister Shinzo Abe say di International Olympic Committee don agree to di delay. ""I proposed to postpone for one year and [IOC] president Thomas Bach don give 100% support,"" Im tok. Di one-year delay go also apply to di Tokyo Paralympic Games. Prime Minister Abe add: ""Dis go make am possible for athletes to play in di best condition, and will make di event a safe and secure place for spectators."" Di agreement come as di British Olympic Association (BOA) dey meet for Tuesday to discuss di matter. BOA chairman Hugh Robertson don already say Great Britain dey unlikely to send team to Tokyo for dis summer." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52022132 +sports Ronaldinho enter police net ontop fake passport accuse "Former Brazil forward Ronaldinho dey police custody for Paraguay ontop accuse say im use fake passport enta di kontri, according to authorities. Police search di hotel for di capital, Asuncion, on Wednesday, wia im dey stay wit im brother. Paraguay interior minister bin tell ESPN Brazil say dem never arrest di two of dem but dem dey under investigation. Minister Euclides Acevedo also confam say di brothers don deny di accuse and dem dey co-operate wit authorities. For July 2019, di player lose im Brazilian and Spanish passports ontop tax money wey im no pay. ""Ronaldinho go get chance by 8amt on Thursday to tok im side of di tori for di prosecutor's office,"" minister Euclides Acevedo tell AFP. E also add say dem go investigate dia own customers authorities join. ""I respect say im na big man for sports but di law no dey respect pesin. No mata who you be, di law still apply to you,"" Oga Acevedo tell local tori pipo. Ronaldinho dey Paraguay to promote one book and do campaign for underprivileged pikin dem. Di 39-year-old win World Player Of The Year two times (2004 and 2005) and im win di World Cup for 2002 wit fellow superstar strikers Ronaldo and Rivaldo." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51744107 +entertainment WIlliams Uchemba: Pretty Mike carry 'six baby mothers' go celebrity wedding for Lagos "Mike Eze-Nwalie Nwogu aka Pretty Mike, one popular Nigerian celebrity, don tok say im carry six women wey get belle go wedding of WIlliams Uchemba because im dey live im best live. Di man wey attend actor Uchemba and Brunella Oscar wedding on Saturday tok dis why for im Instagram where im post picture of imself and di six women. ""Lagos Zaddy live #williamgottheoscar PM and his 6 baby mothers to be... No film trick, we just dey live we best life #ABetterTime #HappyHome #Familyiseverything #babybun."" na so im caption di video and picture wey im post. Dis action surprsie many pipo including celebrity wey don begin dey tok for di account of di Lagos club owner. Dis no be di first time wey di Lagos socialite go burst social media. For February, im tok say one man no fit dey enjoy one fine woman. ""I no know who need hear dis but one man no fit dey hold one beautiful lady only. So, to keep one for yoursef for dis Lagos, you must dey capable to do wetin eleven men fit do,"" na so im tok dat time. For 2017, Lagos state goment arrest am sake of say im put women for chain like dogs come carry dem go event. Plenty pipo and celebrity don dey react to dis new show wey im take women do. Don Jazzy, Kcee, Obi Cubana, Mompha, Lasisi Elenu and BBNaija Dorothy comment for di Instagram post. See as Nigerians for Twitter dey react." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55035900 +sports Champions League fixtures: Manchester City, Real Madrid fit jam Juventus or Lyon for quarter-finals Uefa don release draw for who go play who for di quarter-finals and semi-finals ahead of di resumption of di Champions League. Atalanta, Atletico Madrid, Paris St-Germain and RB Leipzig don already enta quarter-finals before di league bin go on suspension sake of di coronavirus pandemic. All quarter-finals go take place from 12-15 August. Remaining last-16 fixtures on 7-8 August. 1) Real Madrid or Manchester City v Lyon or Juventus 2) RB Leipzig v Atletico Madrid 3) Napoli or Barcelona v Chelsea or Bayern Munich 4) Atalanta v Paris St-Germain Uefa do all three draws, for quarter-finals, semi-finals and one to determine who go be home side for di final as all di matches dem go hold for Lisbon, Portugal.. But dem still get four last second leg matches wey dem suppose play. All di ties go dey for one match, not two legs and e go happun for Lisbon, Portugal for either Sporting's Estadio Jose Alvalade or Benfica's Estadio da Luz. Na for Benfica Estadio da Luz dem go host di finals wey dem move comot Instanbul. Di matches go hold from 7-23 August and dis na how dem plan am. 7-8 August: Last-16 second legs 12-15 August: Quarter-finals 18-19 August: Semi-finals 23 August: Final https://www.bbc.com/pidgin/sport-53365297 +sports CHAN 2020: Caf president say Cameroon na tasting ground Covid-19 measures "Caf interim president, Constant Omari say dem dey use Cameroon as testing ground for Covid-19 measure weh Caf bodi put for ground. Cameroon na de first kontri for Africa for host big football competition since de outbreak of Covid-19. ""We go experiment 25 percent stadium attendance and if e work fain, we go gradually increase de number. Oda kontris go fit also copy"", Omari tell tori pipo. For de African Nations Championship, weh e di start tomorrow, January 16, na only about 12,000 spectators go dey for 40,000 seater Amadou Ahidjo stadium. Dis number represent ova 25 percent of de stadium. Caf interim president say na for start small den, see if de sick di spread or not. As to why players for oda clubs for Africa no fit join make CHAN strong and beta, Omari say Caf exceptions for CHAN na for give value to local championship, give dem visibility for transfer market. Afcon no di reflect level of football for African countries, Omari tok Omari say from weti local organizing competition control tins tok, all tin di waka fain for big opening ceremony. But, for ground disorder dey wit de way de di give accreditation. All man dey for de same place and pipo di stay for hours for get accreditation. As tori pipo di worry about insecurity fo Southwest Cameroon, Omari say, ""Paul Biya don give assurance say Cameroon don take all security measures for Limbe pool afta separatists warn say de no wan catch CHAN for dia territory. ""We discussion, FIFA president myself with president Biya bi fruitful"", Omari tok. Oda tins weh Caf president tok about na election for Caf presidency. E say de di check legibility for candidates for post of president, because de president di become automatically fifa Vice President." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55680120 +politics EFCC invite Femi Fani-Kayode again for questioning over alleged forgery "Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) dey question Femi Fani-Kayode. FFK, as plenty pipo know am follow EFCC officials go dia office afta e finish im mata for Federal High Court Ikoyi, Lagos. According to di EFCC, di former Minister of Aviation, Femi Fani-Kayode bin dey court for hearing on top one case of alleged N4.6bn fraud. FFK dey face trial along wit one former Minister of State for Finance, Nenadi Usman, former Chairman of di Association of Local Governments of Nigeria, ALGON, Yusuf Danjuma, and Join-Trust Dimensions Nigeria Limited. All of dem dey face trial on 17-count charge bordering money laundering to the tune of N4.6billion. Di presiding Judge, Justice Daniel Osaigor of di Federal High Court wey dey sidon on top di matter adjourn di matter till January 24, 2022 for further hearing. However, as Femi Fani-Kayode dey comot from court EFCC officials gada am den carry am go dia office - dis na di second time FFK go go EFCC in one week. One EFCC investigator, tell BBC Pidgin say dem dey quiz di ex-Minister of Aviation over allegation of false documents. Meanwhile Fani-Kayode don react to di development. For statement ontop im social media page, di former aviation minister say EFCC invite am. ""Once again EFCC invite me today. Once again, despite media reports, Dem no arrest but invite me. I reach dia at 11.00am and dem just release me. Thanks be to God!"" E tok. Di former Aviation minister bin honour invitation by di agency about a week ago ontop di same mata. For im reaction to tori wey come out den say EFCC arrst am, Fani-Kayode bin deny di tori say EFCC arrest am. For im statement, e write say EFCC bin invite am and dem no arrest am. ""EFCC no arrest me. Dem in vite me and I fly down to Lagos to see dem."" ""And even if dem arrest me, SO WHAT? I no dey above di law & neither does joining APC give me immunity."" E tok. On Thursday, September 16, 2021, Fani-Kayode cause tok wen im formally announce say true-true e dey comot di opposition Peoples Democratic Party, PDP, to join di All Progressives Congress, APC." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59480398 +entertainment Nuhu Ribadu daughter wedding: Fatima Ribadu and Aliyu Atiku wey be Abubakar Atiku son dey marry dis Saturday- See wetin we know Years ago, Nuhu Ribadu as Nigeria corruption police boss probe Atiku Abubakar as di then Vice President of Nigeria. Today dem wan become In-laws? See wetin we sabi: Local media dey report say Fatima Ribadu di daughter of Nigeria corruption police, EFCC former chairman, Nuhu Ribadu dey marry Aliyu Atiku di son of former Nigeria vice president and presidential aspirant, Atiku Abubakar. Tori be say di wedding go happun on Saturday 3 October, 2020 according to wetin dem put for di invitation card wey BBC Pidgin see. Fatima Ribadu and Aliyu Atiku however never tok anything ontop di mata so far, except for tori wey dey fly upandan Aliyu Atiku Abubakar hold di chieftaincy title of di Turaki of Adamawa, di role wey im take afta im father, di People's Democartic Party, presidential candidate, Atiku Abubakar step down to become di Waziri of Adamawa State for 2017. Turaki Adamawa na one of di most important posts for di Adamawa Emirate administration. Aliyu also be banker and director for Priam Group, im father group of plenti companies wey be di largest employer of labour for Adamawa state. Im also be politician like im papa. Fatima Ribadu na one of di five children of former Nigerian police officer and di chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC. She be close friend wit President Muhammahu Buhari daughter, Hanan. Hanan wey be photographer share series of Fatima pictures on her instagram page for December 2016. Nigerians don take to social media to tok about di wedding of di children of di two strong politician from opposition parties. Atiku Abubakar na from di People's Democratic Party while, Oga Nuhu Ribadu na politician from di All Progressive Congress, APC. Though di two politician bin come from Adamawa State for di north-eastern part of Nigeria. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54352012 +sports Christian Chukwu: Former Super Eagles coach 'embarrassed' by fake news of e death "Former Super Eagles Coach, Christian Chukwu say im dey embarrassed say fake tori of im death don spread for Nigeria. Di former footballer wey deny di news of e death say im dey hale and hearty. Earlier on Sunday, tori begin fly up and down say di ex-Rangers player and Green Eagles captain don die Chukwu for interview wit News Agency of Nigeria say im dey ""terribly embarrassed with dis news wey say I don die."" Im say ""Several pipo begin call me from across di world since di news brake. I still dey investigate di source of di story."" Dis no go be di first time wey fake tori about di life of di former Rangers Technical Director go make news, for 2019, one rumuor bin spread wey say both Rangers Football Club and Enugu State goment bin abandon Chukwu when im bin need money for medical treatment abroad. Di defender play for Enugu Rangers Football Club during di 1970s and also captain di Nigeria National Footbal team den, popularly known as di Green Eagles. Chukwu na di first Nigerian captain to lift di Africa Nations Cup, when Nigeria win am for 1980. As coach, Chukwu coach di Super Eagles of Nigeria for 2003 reach 2005. Im also coach di Kenyan national team for 1998 and Rangers for 2008." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55610928 +health Ghana coronavirus tracker: How govment spend $9,383,487 on cooked food during three-week Covid-19 lockdown Total sum of money wey govment spend on cooked meals give vulnerable people during de Covid-19 lockdown dey raise questions among Ghanaians. Finance Minister, Ken Ofori-Atta reveal during mid-year budget review say govment spend GH¢54.3 million ($9,383,487) on cooked food to some 470,000 families within Accra and Kumasi during de three-week lockdown. Some of de meals dem share dey include fried rice and chicken, kenkey and fish, jollof rice den stuff give de vulnerable groups. So govment spend GH¢54.3 million on 470,000 people for 21 days of daily meal packages. On average, de estimate of one food pack go cost like GH¢5. So for how much each person go spend dis go be GH¢5x21 days = GH¢105 Now make we multiply GH¢105x470,000= GH¢49,350,000 Total amount wey we arrive at be GH¢49,350,000, so make we subtract am from de GH¢ 54,300,000. Therefore GH¢ 54,300,000- GH¢49,350,000 = GH¢4,950,000. After de calculations you go get difference of GH¢4,950,000. We no sure what dis figure dey cover but e fit cover things like service charge and transport. President Akufo-Addo on March 27 place Accra and Kumasi under lockdown sake of de spread of Covid-19 within these regions. De lockdown wey last three weeks create massive inconvenience give vulnerable groups like head porters, de homeless, street dwellers den stuff who dey feed on dema daily wage. A cross section of Ghanaians however feel de figure no dey correspond to de meals dem share, quality of de food den stuff. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53523715 +health Ghana health officials warn against 'contaminated' imported gizzard "Bureau of National Investigation for Ghana start dey investigate how three 40-footer containers of infested salmonella gizzard enter de country. Veterinary officials for Ministry of Food and Agriculture seize one containers for de port at the port, but three others already leave de port. Veterinary official for National Food Safety Laboratory, Dr Bashir Kikimoto talk BBC Pidgin day ""dis be public health risk sake of millions of people go for suffer health issues like gastrointestinal disturbances, Crohn's disease, fever, headache den stuff."" He add say ""people wey get weak immune systems like kids den adults above age 60 go fit die if dem chop dis contaminated gizzard."" BNI officials start dey investigate executives of two import companies who dem say dey begins de importation of de contaminated gizzard wey dem import from Brazil. Authorities say dem no sure where exactly de three 40-footer containers dey currently that be why dem notify BNI. But for now National Food Safety Laboratory officials say make de general public shun dey buy any imported gizzard. Until say dem resolve dis issue make dem buy Ghana made gizzard products for dema safety." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51536046 +sports Chelsea fit turn attention to Maguire if Fofana deal fail Newcastle United don make club record £60m bid to sign Real Sociedad 22-year-old Sweden striker Alexander Isak. (Mail) Chelsea fit move for Manchester United and England defender Harry Maguire, 29, if dem dey unable to sign French centre-back Wesley Fofana, 21, from Leicester. (Evening Standard) Ajax dey hold out £84m for 22-year-old Brazil winger Antony, wey dey determined to push through move to Manchester United. Im representatives dey England to help get di deal done. (Telegraph - subscription required) Antony hand in transfer request on Wednesday in order to make im desire to comot di club, official. (Mirror) Liverpool don make offer to Barcelona for 25-year-old Dutch midfielder Frenkie de Jong. (Futbol Total, via Forbes) West Ham get dia 50m euro (£42.2m) bid for 24-year-old Brazil midfielder Lucas Paqueta rejected by Lyon. (L'Equipe, via Metro) Arsenal no dey expected to move for Paqueta despite reports wey say dem dey interested. (Express) West Ham get offer to sign Arsenal and England midfielder Ainsley Maitland-Niles, 24, in di closing weeks of di transfer window. (Mail) Southampton and Bournemouth dey also discuss possible deal for Maitland-Niles, wit Arsenal open to loan move wit option to buy. (TalkSport) Manchester United don hold toks wit Newcastle United ontop di signing of Slovakia goalkeeper Martin Dubravka, 33. (Mail) Di clubs neva reach agreement but Manchester United don submit loan offer for Dubravka. (Athletic - subscription required) Manchester City chief executive Ferran Soriano don rule out di possibility of Portugal midfielder Bernardo Silva, 28, leaving di club dis summer. (SER Catalunya, via 90min) Ajax 20-year-old Dutch striker Brian Brobbey say im reject di chance to join Manchester United afta im former boss Erik ten Hag send am message. (Voetbal International, via Star) Aston Villa don reduce dia asking price for defender Frederic Guilbert as dem dey look to sell di 27-year-old Frenchman. (L'Equipe, via BirminghamLive) Nottingham Forest dey interested in signing Ivory Coast right-back Serge Aurier, 29, wey dey available on free transfer afta leaving Villarreal. (Sun) Chelsea 21-year-old England midfielder Callum Hudson-Odoi dey set to join Bayer Leverkusen on loan. (Guardian) Everton dey in discussion wit Manchester United ontop one move for 21-year-old English midfielder James Garner. (Athletic - subscription required) https://www.bbc.com/pidgin/articles/c9rqr355xg1o +entertainment Rich Oganiru Biography: Nollywood actor Rich Oganiru death - How friends, odas mourn Nollywood Veteran actor, Rich Oganiru don die. Oganiru death occur weeks afta e bin go public about im health palava. Two Friends to late Rich Oganiru confam di news of im death for dia verified social media pages. Emstar Vee wey be one of di actor friends write say di actor die on di 10th of August 2021. James Okocha, anoda friend of di actor, post for Facebook say e no fit forget how di late actor sing for am last year August during im birthday. Few weeks ago, one video of late Rich Oganiru appear for social media. For di video di wey look very sick, lie down for bed dey ask for financial assistance. Rich Oganiru, don dey di Nigerian film industry for almost 20 years. Rich Oganiru don feature for ova 300 movies wey include; Queen of Hasso Rock, Wasted Effort, Pay Day, Lacrima, Stoneface in Love. E also act Givers Never Lack, His Majesty, Yellow Fe Rich Odichinma Azu ver, Odas include 'My Destiny, Battle Of The Rich, Political Control, Touching Love, Total Control, and Last Confession plus many odas. For September 2012, local media report say police authorities for Abuja confam say dem arrest Rich Oganiru. Dat time dem dey investigate am in connection with di alleged killing of im wife. Local media say dis arrest na afta di petition from di family and relations of di late wife. Oganiru in-laws bin dey point accusing finger on di actor. Rich Oganiru deny di accusation say e dey innocent, but afta all dis, im acting career come drop. Before im die, Rich Oganiru na di Corporate Marketing Consultant to di Abuja Chapter of AGN,. Oganiru also serve as one Evangelist with Davidical Order Ministry. https://www.bbc.com/pidgin/58177665 +politics Edo state election 2020: Meet di main contenders for di 2020 govnorship elections Govnorship elections for Edo state south west Nigeria go soon happun and as part of di preparations, political parties for di state don warm up for primaries on June 22. According to di Independent National Electoral commission (INEC), 15 out of di 18 registered political parties don invite dem to come monitor dia primaries. Inside dis 15 parties, e get some wey get very strong candidates wey be di main contenders for di post of Edo govnor. Govnor Godwin Obaseki dey find second term for office but APC screening committee disqualify am on top alleged fake certificate. Di All Progressive Congress screen six candidate for the govnorship primaries on June 12. Out of di six, three of di candidates, Osaro Obaze, Dr Pius Odubu and Pastor Osagie Ize-Iyamu make am. Di remaining three including govnor Godwin Obaseki dey disqualified, even though University of Ibadan come out to confirm say di certificate dey authentic. As e be so, e neva clear weda Oga Obaseki go port go di Peoples Democratic Party to contest second term. Still, as di long time katakata between Obaseki and former Edo state govnor wey be APC national chairman now, Adams Oshiomole reach climax, di party dey warm up to give dia support to anoda candidate, Pastor Osagie Ize-Iyamu. Osagie Ize-Iyamu na pastor and politician. Im bin contest against Obaseki for di 2016 govnorship election as candidate of di opposition Peoples Democratic Party. Pastor Ize-Iyamu dey for di centre of di battle between Godwin Obaseki and Adams Oshiomole, and ot of di three candidates wey pass party screening, im na di candidate wey dey enjoy Oshio Baba support pass to represent APC for di 2020 election. Im be one time chief of staff and secretary to di Edo state goment. E serve as Director General of Adams Oshiomole second term Campaign Organisation for 2012 and coordinator of Goodluck/Sambo Campaign Organisation. Ogbeide Ihama na member of di Nigeria House of Representatives wey dey represent Oredo Federal Constituency of Edo state. Im follow among di three candidates wey di Peoples Democratic Party clear for screening to contest for di party indirect primaries. Oda candidates wey go contest for di primaries, Gideon Ikhine and Kenneth Imansuangbon Di leading opposition Peoples Democratic Party get strong presence for Edo state and dem dey hope to collect Edo state back from di ruling APC. https://www.bbc.com/pidgin/media-53033036 +entertainment Kizz Daniel apologize plus explain wetin truly happen for Tanzania "Nigerian musician Kizz Daniel don apologize give im fans and pipo of Tanzania and promise to do free show. Kizz Daniel suppose perform for Summer Amplified Show for Tanzania but no come fit perform sake of' circumstances wey pass im power.' ""I must apologize to di fans. None of dis dey intentional I love my job, especially I love performing, I be great entertainer."" ""I no mean to disrespect di fans, e no dey intentional at all."" ""I want to perform. I come Tanzania to perform but because of circumstances wey pass my power, we no fit make dat happun."" ""I apologize once again to di pipo of Tanzania and I hope say una go give me anoda chance to give una proper and beautiful show."" Di popular Buga singer promise to make up for wetin happun by doing free show dis Friday. ""Regardless of di story, news and press out there, di show go still go on."" ""We don reach agreement to put up a show dis Friday and na free show e go be,"" Kizz Daniel tok. On Monday, news and video of kizz Daniel arrest flood social media platforms. Dis na afta fans wey bin come to see di Nigerian singer perform begin para dey scata things for di show venue as dem no see am. Dis come make di organisers of di Summer Amplified Show for Tanzania to involve police on top di mata. For one press conference on Tuesday night, Kizz Daniel share im side of di story. Di popular Buga hitmaker say one agency contact am back home to come perform for Tanzania on di 7th. ""I suppose dey Uganda on di 6th, so I feel okay well, e go only dey nice to drop in and say hello to my Tanzania pipo."" E say di agency tell am say di promoter of di Tanzania show don already book one connecting flight for am to leave Uganda 7th of August to Dar es Salaam, Tanzania."" Kizz say e im comot hotel 6:00am for di airport but ufortunately, di airline for Uganda delay di flight for one hour before dem travel. By di time dem land Kenya, di connecting flight from there to Dar es Salaam don already leave. ""So we inform di show organizer wetin happun and ask if we go still fit make am to di show as na around 12noon we enta Nairobi."" Di show promoters promise to get di next available flight to Dar es Salaam and kizz Daniel say e wait for over 8 hours for airport inside Nairobi ""Around 8:45pm, we enta plane and fly straight to Dar es Salaam and land there around mid-night."" Kizz Daniel say wen dem land Dar es Salaam, dey find out say di airline forget dia bags and some equipment for Kenya. Dey inform di show organizer and di airline. Then, di airline promise to get di bags. And by di time e send im band to di venue of di show to do sound check, angry fans wey don already dey there chase dem away. Dis bad news no stop am as e contact some Tanzania stylist for cloths for di show. Kizz also explain how some unresolve issues between di agency back home and di promoter also cause delays. But by di time dem reach agreement to continue with di show, di fans don vex. E say dem advise am to stay back for im own safety. Di Nigeria arstist say police later dey involve for di mata because of di vandalism wey happen for di event venue. Kizz Daniel add say police no arrest am but invite am questioning relating to di destruction of property. Organisers of di event, Big Step Consultancy apologise give di public ontop wetin happun for di Summer Amplified concert. Big Step Consultancy say dem pay Kizz Daniel im full money before e fail to perform on 7 Agust, 2022 as dem bin plan. Dem assure di public and fans wey pay and show up for di event say dem go do all dem fit do to make sure say dem hold every pesin wey dey involve accountable. And assure dia fans and customers say dem go handle di mata wella. Nigerians in Diaspora Commission play role for di release of Kizz Daniel afta Tanzania police involve for di incident. Di commission first confam for social media say, Kizz Daniels dey Oyster Bay Police Station Civil Police for Dar es Salaam, Tanzania. And add say dem do tok-tok with dia mission to see how to settle di mata. Later, Chairman, Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa announce through her Twitter handle say dem don release Kizz Daniel. Madam Abbike add say lawyer to Kizz Daniel go report to di station di next day. Mixed reactions na im dey come from Nigerians afta dem don get to know di two sides of di story. While some Nigerians dey blame di Buga singer say e suppose land for Tanzania earlier like four days before di show. Odas dey try reason di mata with am for social media. One twittter user say; ""There’s a little kizz daniel in all of us. Dis Adult thing hard Abeg. I want money and I no really really like working for iam like dat, so I kinda get it."" Kizz Daniel na popular Nigerian musician wey dem born for Abeokuta, Ogun state. E real name na Oluwatobiloba Daniel Anidugbe. Na 2014 di singer release im debut single, Shoye, G-Worldwide Entertainment label. Some of im hit songs na 'Woju', 'Yeba' and 'Buga'. For 2017, afta di wahala wey im bin get wit im den record label G-Worldwide Entertainment dat na afta dem carry am go court on top songs wey im wan release without di company approval, e change im name from 'Kiss Daniels' to Kizz Daniel. One of im recent song 'Buga' dey ginger many pipo for Nigeria, Africa and di world." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c5173lgllllo +sports Tokyo Olympics: Nigeria, Ghana dey ginger to bring Olympics glory for West Africa Na one week remain for di start of di Summer Olympics for Tokyo, Japan as countries all over di world ready for victory and glory. West African countries too follow with di hope say dia athletes go shine inside event wey don already witness one year delay because of di pandemic. Di last time wey Ghana win medal for Olympics na for 1992 and currently none of dia athletes be strong contender. But Ghana Olympic Committee oga Ben Nunoo Mensah bin tok for August 2020 say hope dey because “for sports anything fit happun”. But oda kontris get more belief pass dis - like Nigeria wey don win 3 gold medals - including di famous one for Atlanta 1996 wia dem beat Brazil for men’s football final. Make we torchlight how West Africa dey ready to showcase demsef dis time around. Athlete(s) to watch Nadia Eke - Triple Jump Accra-born Eke na key hope for Ghana because of her years of experience and ogbonge training for di United States. 28-year old Eke bin first win bronze for di 2015 African Games for Brazzaville, after which she carry gold for 2016 di Africa Championships wey happun for South Africa. Na she go also be di flag bearer for di Ghana Olympics team. Athlete(s) to watch Blessing Okagbare - Athletics (various) 32-year old Blessing ‘Mountain’ Okagbare go dey compete for her third Olympics in a row, in order to add to her 2008 Silver medal for Beijing. She dey versatile as she dey compete for different events like Long jump, sprint and relay. Although she only qualify for 100m, 200m, and 4x100m relay for di 2020 Olympics. In total she don personally win 12 gold medals for her career inside competitions across di world. Odunayo Adekuroye - Wrestling Odunayo Adekuoroye na anoda athlete wey Nigeria get hope on say she go deliver medal for Tokyo. Di freestyle wrestler don already win two gold medals for Commonwealth Games (2014 and 2018) and get Silver for 2017 World Championships. And while di world bin dey battle Covid-19, she win gold 57kg wrestling event for di 2020 African Wrestling Championship, and anoda gold for Poland dis year. But wetin Adekuoroye - wey tori say dey train up to 9 hours daily - go really eye, na Olympics victory. As di World number 4 for her weight class (United World Wrestling Raking), di whole of Nigeria dey tanda gigigba behind di 27-year old champion to go for Gold. Nigeria Women Basketball team Although na dia men counterpart dey tori now for dia victory over Team USA and Argentina for friendly basketball match dem play recently, na Nigerian female Basketball team many dey torchlight to carry medal return. D’Tigress (wey be dia nickname) na di current AfroBasket champions, after dem carry gold for di contienental competition for 2019. Dis go ginger dem to do di same on di work stage. Athlete(s) to watch Cheick Sallah Cissé - Taekwondo 2016 Olympics Gold medallist Cisse go dey look to defend im title for di 80Kg category. Cisse na also di athlete wey help im kontri to win dia first and only gold medal. Di 2020 Olympics for Tokyo, Japan go run from 23 July to 8 August, 2021. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57857658 +politics Governor Wike say dem recover Rivers state aircraft previous goment abandon for Germany "Rivers State Governor Nyesom Wike say di state goment don discover one state-owned aircraft wey di previous administration of former Governor Chibuike Rotimi Amaechi allegedly abandon for Germany since 2012, without any documentation. Governor Wike say na through intelligence dem discover di aircraft wey dey Munich Germany without any documentation and e cost di state over three million euros, (€3million euros) wey be about one point four billion naira (N1.4billion) to repair and recover di Legacy 600 aircraft. Di Rivers State governor as e carry some leaders from di state go General Atomics Aerotec for Munich Germany go see di Legacy 600 aircraft say im administration discover di aircraft in dia effort to recover state assets. Governor Wike for meeting with di General Manager Business development of General Atomics Aerotec Markus Froetschi for Munich Germany say,""Wen we enta office for 2015, we no get any idea say our plane dey your facility. Na as we begin ask questions na im we get information say di Legacy 600 wey belong to our state dey RUAG, before General Atomics. We try make contact with you and you oblige us so we sincerely thank you say you no hide anytin from us because na property of di State goment."" Di Governor say na for 2003 di goment of Dr. Peter Odili buy di plane and by 2007, e hand over to di next goment wey Chibuike Rotimi Amaechi, di present Minister of Transport lead and na wen im dey for office dem carry di plane go Munich for 2012 and di reason why dem carry am go, dem no know. ""Di issue be say, why e no get any documentation wey let di incoming goment know say we send our aircraft go RUAG for inspection again, I know from experience say dat kain inspection of such facility no dey take more dan six months, so if dem bring am for 2012, e dey expected say at least by 2013, dem suppose don bring di plane come back for use."" Di General Manager business development of General Atomics Aerotec Markus Froetschi say na for 2012 di immediate past administration bring am and abandon am dia. E say e happy as di state goment don take di initiative to repair and return am to Nigeria. E say dem go finish di general maintenance work and deliver do aircraft to di goment by March 2022. APC blast Wike But di opposition don blast Govnor Wike for im 'discovery'. “E dey wonderful say Governor Nyesom Wike say im no know about dis aircraft wey im say dem hand over to administration wey im serve as chief of staff from 2007 to 2011."" Dis na wetin di spokesperson elect for di opposition party, di All Progressives Congress APC, Chris Finebone tok. Di APC wia di present Minister for Transport, Chibuike Rotimi Amaechi be di leader of di party for Rivers State say di govnor never tok all im know about di aircraft and e no dey enough for am to claim say im just discover di present location of di aircraft somewia for Germany by some cuni-cuni intelligence. Chris Finebone tell BBC Pidgin say, ""di truth be say, di govnor know evritin about di aircraft and di circumstances wey lead to di present location wia e dey now for Germany even before dem swear am into office for 29 May, 2015. Di govnor you know for don go CNN raise alarm. Im carefully pick di pipo e carry go for di political drama wey dey play out and we know why."" Im tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60138569 +politics APC shortlist 13 presidential aspirants ahead of primaries "Nigeria ruling All Progressives Congress presidential committee don drop 10 aspirants from dia presidential primaries wey go hold next week. Chairman of the Committee, John Odigie Oyegun, tell tori pipo on Friday say di APC ""shortlist only 13 people"". According to Oga Oyegun, committee only clear 13 out of di 23 aspirants wey dem screen. Im add say na only youthful aspirants make di list of cleared aspirants. However wen dem ask about di identity of di disqualified aspirants, Oga Oyegun no gree disclose di names. Di party go hold further screening exercise to trim down di list further, according to Oyegun. Cleared aspirants dey expected to contest di presidential primary for one scheduled special convention for Abuja between June 6 and 8. Oga Oyegun say im no dey aware wether former president Goodluck Jonathan dey di screening process. E further tok say no be im committee go tok wetin be di outcome of di screening, di pipo wey send am work get di report of di screening and na dem go come out to tok wetin dey. E also tok say im no dey aware wether dem disqualify anybody but wetin im sabi be say most of dem be high quality pipo and dem pass di basic test. Di APC chieftain Odigie Oyegun say na di party management go decide wether di primaries go be through elective or consensus as wetin im committee do na to tell di management say dis pipo qualify. E add say, “to govern a kontri no be joke, you go look at di background of evribodi, you go look dia idea, you go look dia appreciation of di realities of di Nigerian politics and dat is it. ""Di more experience dem get, di more contribution dem don make to di nation, di more contribution dem make to di party sef, to make am di governing party.” Chairman of di screening Committee of di presidential aspirants of di All Progressives Congress John Oyegun during di tok wit tori pipo say di party look at “young aspirants wey Nigeria need"" and “na on dat basis di committee decide to bring down di number of aspirants down to 13. Apart from age, di chairman also say dem consider oda tins to bring down di number of di presidential aspirants. However e no clear wetin chief John Oyegun mean by “youthful aspirant” wey di screening committee shortlist. A youth for Nigeria dey categorized under 18-35 years. Also, according to di Not Too Young To Run Act wey President Muhammadu Buhari recommend 30 years as benchmark for pesin to contest for di office of di president. None of di presidential aspirants dey within di age range. All of dem dey 40 years and above. Meanwhile according to current record of aspirants wey buy form, dia age range na between 40 and 73. Current Vice president of Nigeria and one of di aspirants, Yemi Osinbajo, na 65 years professor wey serve as Attorney General of Lagos State from 1999 to 2007 and hold di title of Senior Advocate of Nigeria (SAN). National chieftain of di APC, Asiwaju Bola Tinubu na 70-year-old former govnor of Lagos state. Im rule di state between 1999 and 2007. Anoda aspirant, Rotimi Amaechi dey 57 years. Im too don serve as former govnor of Rivers state. E rule di state between 2008 and 2015. Amaechi serve as Minister of Transportation before e resign to come contest for president. Order aspirants include:" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cl72r9r1p0lo +entertainment BBNaija eviction today: Beauty disqualified, Christy O, Cyph dey evicted from season 7 show - How Nigerians react Beauty don dey disqualified from di BBnaija season seven show afta she collect three strikes. Meanwhile Christy O na di first house mate to dey evicted from di season while Cyph na di second. Beauty dey disqualified afta she throw her wig and glasses for Groovy body afta dia Saturday Night Party. She collect Double Strike from Biggie for her actions. She bin don get one strike from di previous week as she quarrel wit anoda housemate Ilebaya afta dia Saturday night party. She and Groovy bin dey inside some sort of 'situation ship' for di house and Beauty bin para say e dance with anoda housemate, Chomzy for di party. Big Brother make dis announcement as millions dey glued to dia TV, social media, phones and devices dey wait for di host of 'Africa biggest TV reality show' Big Brother Naija to climb stage for di live eviction show to announce who go dey evicted. Sunday 7, August live show dey different because na di first eviction show of di Big Brother Naija Season 7 level Up show. Di housemates dem don stay di house for two weeks now. Five pipo bin dey up for eviction. Cyph, Christy O, Khalid, Phyna and Amaka. 24 housemates na im initially join di house for two different house levels - Level one and two. But dis week Head of House, Hermes get di authority to nominate five pipo for eviction and e do so. Beauty wey her full name na Beauty Etsanyi Tukura na 24-years-old lawyer from Taraba state. She be Ex-miss Nigeria. She bin tell her oda housemates say she dey passionate about advocacy. On Sunday night for di eviction show, Biggie introduce new twist - two new Housemates wey e call 'Riders'. Biggie say dem go dey involved in every aspect of di show till di last day but dem no fit win di grand prize. Biggie introduce two riders - Chizzy and Rachel to di house. Christiana Oluwafunke Ojumu alias Christy O na 24-years-old beauty entrepreneur from Ondo state, southwest, Nigeria. Cyph real name na Bright Hidi Nwekete. E be Electrical Engineering graduate from Imo State. Some reactions to Cyph eviction. Although Beauty break record as di first housemate wey go dey disqualified dis early on into di show, she no go be di first to dey disqualified. Di last housemate wey dey disqualified for di lockdown edition of di show for 2020 na Erica. Odas wey also dey disqualified for different seasons for di show na Tacha for 2019. Khloe and K Brule for 2018 and Kemen for 2017. Di show don do six seasons and don get six winners. Katung Aduwak, Efe Ejeba, Miracle Igbokwe, Mercy Eke, Olamilekan Agbeleshe and Hazel Oyeze Onou be di winners of di previous seasons respectively. Di show popular not only for di money and gifts di winners and participants dey enjoy, but also for di opportunities wey participants dey enjoy wen dem commot from di house. Dis season winner walk away with ₦100 million worth of prizes, including a cash sum of ₦50 million. Big Brother Naija na di Nigerian Franchise of di reality show Big Brother. Na reality show wia contestants dey live for isolated house and dey compete for a large cash prize by avoiding eviction by di viewers. Some analysts say BBNaija na Africa biggest reality show. Na MultiChoice Nigeria dey organise am. But di show dey draw criticisms say na big distraction for di youths and some pipo dey against am for not promoting 'morality'. But every year since e seven season run - during di months e dey air, e dey dominate social media conversations on Twitter, Facebook, Instagram and elsewhere. During di period e dey on, Big Brother Naija dey drive engagement and conversations for social media even as much as politics. Di programme dey air not only for Nigeria, but for 48 oda African kontries, to an average audience of 309 million viewers according to DSTV media sales figures. With peak viewing for di beginning of di programme, some eviction shows, and di finale. As expected, di live eviction show top trend for Nigeria social media spaces. E even become more of a talking point because of di different drama wey happun. Beauty chop disqualification, Biggie introduce two riders and two housemates chop eviction. Meanwhile, Christy O no do di usual afta eviction stage tok as she tell di organisers say she no wan tok. https://www.bbc.com/pidgin/tori-62447082 +sports Players wey cough on purpose fit collect red card, tok Ifab & FA "Players wey cough for di face of oda players or match officials fit begin collect red card, according to football rule-makers and England Football Association. Di International Football Association Board (Ifab) say dat kain offence dey inside di same category as di one to dey ""use language and oda actions to take insult or abuse pesin"". ""Like all offences, di referee need to make judgement about di true nature of di offence,"" tok Ifab. Dis new guidance dey come as di world dey face coronavirus pandemic. ""If to say na mistake, then di referee no go take action and also if di 'cough' happun when players no dey near large distance between the players. ""But wia e be say pesin dey close to who cough on purpose, then di referee fit take action."" Di FA for England don also release dis guidance for grassroots football wey go take effect immediately. Inside document dem write say If di mata not serious to deserve red card, dem fit produce yellow card for ""unsporting behaviour"". Dem also draw ear give referees not to begin punish normal coughing and say na only case wey e dey clear pesin dey use cough do anoda pesin bad. As dem no write di law to cover Premier League and English Football League, na di referee go use im 'church mind' to determine di punishment." https://www.bbc.com/pidgin/sport-53635848 +politics Obaseki react to court suit wey wan stop am to contest inside PDP primary for Edo state "Special adviser to Edo state govnor for media and communications strategy, Crusoe Osagie, tell BBC say one mata wey dey Federal High court for Port Harcourt, Rivers state wey wan stop Godwin Obaseki to participate for di opposition Peoples Democratic Party primary no go stand as e dey against im right to freely associate. Oga Osagie say, e no dey possible for anybody to say im dey vex becos Govnor Obaseki join PDP becos di govnor move to contest primary for PDP, dem do am according to di rules and law and principles of di party. Dis reaction dey come afta one federal high court for Port Harcourt, Rivers state grant request to hear di mata wey wan stop di Edo state govnor sharp-sharp. ""As long as im no break di law of di constitution, e no get any reason for anyone else to disrespect anybody right. ""Di waiver wey di govnor get follow all di due process according to di constitution of di PDP to give am di waiver, if you tok of im joining di party, dem make sure say dem follow di rules of di party to add am for di party. So im no break any PDP constitutional rule and dat na why we know say di court go troway di decision, im tok. Di govnor lawyers don already dey try solve di mata of di High Court decision. Di order of di Federal High Court for Port Harcourt to hear di suit wey wan stop Obaseki dey come, afta PDP govnorship aspirant and di House of Representative member wey dey represent Oredo Federal Constituency, Omoregie Ogbeide-Ihiama,file suit make Obaseki no follow do di party primary wey go happun on June 25, 2020. Im say only those wey buy form during di timeframe di party bin lay down suppose dey allowed to participate for di primary. Justice Emmanuel Obile, move di case to June 24 for hearing. ""We believe dem go allow di law to take im course and wen dat one happun, dem go allow my govnor to exercise im right. I mean im na citizen of dis kontri and im dey free to associate wit any group as long as im do am according to di law wey rule dat group,"" Oga Osagie tok. Govnor Godwin Obaseki port go PDP on Friday 19 June, afta im formally announce im decision to resign as All Progressive Congress party membership on Tuesday 16 June We don update dis tori.g" https://www.bbc.com/pidgin/tori-53159286 +sports Europa League results: Amad Diallo, Simon Kjaer score as Man United draw 1-1 with AC Milan "AC Milan defender Simon Kjaer score late goal to deny United victory for dia first leg of di Europa League round of 16 encounter. Kjaer goal for added time hand AC Milan crucial away goal as di game end 1-1 ahead of di second leg. Simon Kjaer header na di first goal wey United go concede in five matches. Ivory Coast teenager Amad Diallo bin score e first goal for Manchester United afta e come on as second half substitute. 18-years old Diallo Bruno Fernandes over di top pass beyond di reach of Milan goalkeeper Gianlugi Donnaruma for di 50th minute. Dem born Diallo for Ivory Coast, and na 18 years im be. Tori be say e move go Italy around di age of 10, and join Atalanta for 2015. Di winger play im first match for Atalanta last season, wey make am di youngest player - at 17 years and 109 days old - to score for im Serie A debut in for dia 7-1 thrashing of Udinese. Afta dat im performance, di Ivorian travel wit di Atalanta squad to Lisbon for dia Champions League quarter-final defeat to Paris Saint-Germain last summer. Diallo play just four league games for Atalanta, but e shine well-well for training, sotey former Atalanta captain Papu Gomez recently compare am to Lionel Messi. ""E get defenders for di first team wey no fit stop am sometimes. To stop am for training, we dey kick am! im dey play like Messi,"" na wetin Atalanta captain." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56368028 +entertainment VMAs 2019: Missy Elliott collect Video Vanguard Award Grammy winning rapper, Missy Elliott, don receive di Video Vanguard Award for di MTV Video Music Awards wey happun for America. Dis one dey come afta plenti of her fans don dey ask music giant MTV to give am di award because of her contribution to hip hop and music videos. She be di first female rapper to carri di award. Different celebrities like Justin Timberlake, Lil Kim, Pharrell and Timbaland pay tribute to di singer on how she don contribute to music and how her videos dey iconic. Missy Elliott perform some of her hits like Get Your Freak On, Hot Boy, Lose Control and her new single Throwback wey dey from her new EP, Iconology. She even bring Alyson Stoner come stage, wey be di small pikin wey dey her 'Work It' video. As she receive di award, pipo dey hail am. Missy show love to all di pipo wey she don work wit through out her career from Timbaland to Hype Williams, Janet Jackson and Laurieann Gibson. She end her speech as she remember her friend, di singer Aaliyah, wey die for 2001 and dancers around di world. The Michael Jackson Video Vanguard Award na for musicians wey don do well for music and feem and di award na gold instead of di normal silver one wey oda winners of di night dey carri. Oda winners of dis year MTV Video Music Awards include Taylor Swift, Cardi B, Normani, Ariana Grande and Li Nas X. Di MTV Video Music Awards na one of di ogbonge awards for America wey dem dey give pipo wey don release good music videos. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49480510 +sports Chelsea enter race for De Jong, Man Utd don give up on Ronaldo Chelsea dey��set to offer Spanish players Cesar Azpilicueta and Marcos Alonso plus £51m to beat Manchester United for race to sign Barcelona's 25-year-old Netherlands midfielder Frenkie de Jong. (Metro) Manchester United dey willing to listen to offers for Cristiano Ronaldo dis summer as interest from Chelsea and Napoli dey continue for di 37-year-old Portuguese. (Sky Sports) Monaco's Wissam Ben Yedder don emerge as serious contender to replace Cristiano Ronaldo if di Manchester United forward finally leave.(Sky) Tottenham dey close to completing di signing of Barcelona and France centre-back Clement Lenglet, 27, on season-long loan deal. (Standard) Arsenal dey consider move for Benfica 26-year-old Spanish left-back Alex Grimaldo, as Mikel Arteta dey eager to get cover for Kieran Tierney. (Mirror) Ajax don ask Manchester United to pay combine transfer fees of £106m in order to sign Argentina defender Lisandro Martinez, 24, and Brazil winger Antony, 22, from dem. (Daily Record) Na Chelsea remain favourites to sign Raphinha for £55m, but Leeds still dey wait for offer from Barcelona for the 25-year-old Brazil forward. (Standard) Portugal forward Fabio Silva, 19, go join Anderlecht on season-long loan from Wolves, who buy am for £35m two years ago. (Mail) Inter Milan don make dia opening move for highly-rated Torino defender Gleison Bremer, according to Sky in Italy. Angel di Maria don arrive Turin wia e go undergo medical ahead of im free transfer move to Juventus.(Sky) As dem don agree personal terms with Raheem Sterling, Chelsea dey now put the final touches on di deal with Manchester City for di English player (SB Nation) https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0w724v632eo +sports "Pep Guardiola: Manchester City football manager Josep ""Pep"" Guardiola Sala sign two year deal" "Manchester City FC boss Josep ""Pep"" Guardiola Sala wey be Spanish football manager don agree sign two year deal wey go keep an as di manager of Manchester City till 2023. Di 49 year old don win two Premier League titles, di FA Cup and three League Cups since im join di club for 2016. Im former contract suppose to expire by di end of dis Premiere League season. Already with out di extension, im five year stay for City na di longest time, di former Barcelona and Bayern Munich manager don stay for one club since e start to do manager work for 2008." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55004225 +politics Atiku, PDP don appeal presidential election tribunal judgement Presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) for di 2019 general elections, Atiku Abubarkar don file appeal against di judgement of di presidential election petition tribunal for Supreme court. Atiku and di PDP wan make di Supreme Court throway di judgement of di tribunal wey rule on di mata on September 11 say President Muhammadu Buhari victory for di 2019 election na correct. Di opposition candidate and im party file di appeal on five grounds, wey include matas wey concern President Muhammadu Buhari certificate. Before now, di Tribunal been uphold say President Buhari qualify to contest and dat no evidence dey to show say e no go school. Di tribunal say di candidate no dey required by di Electoral Act to attach im certificate to im Form CF001 before di candidate go show say im dey qualified to contest di election. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49812059 +entertainment Psquare news: Paul and Peter Okoye wives tok afta di twins reunite plus how fans react "Psquare reunion don cause reactions from fans, colleagues plus dia families. Di Nigerian twins - Peter and Paul Okoye - bin get gbege ontop one family mata for 2017 wey make dem split. Nigerians wake up on Thursday to one Instagram video message wey show say dem two don settle dia quarrel as dem jointly celebrate dia 40th birthdays. E no dey clear if di brothers go make new music together, but fans, don enta social media to celebrate dia reconciliation, Anita Okoye wey be one of di twin, Paul Okoye wife say dis na di best birthday present. For one Instgaram post, Anita thank di brothers say dem allow dem get great relationship wit dem even as dem two dey quarrel. ""I dey happy say I no let una coconut heads make me choose sides"", she tok. Lola Omotayo-Okoye wey be Peter wife also comment to say she dey happy say di brother don finally put dia differences aside and allow love guide dem. ""Peter and Paul, you be ONE no be Two!"", she add am. Popular OAP, Toolz O also comment to say she bin don dream am say di brother go come back togeda. Psquare bin dominate di Nigerian music scene for years and dem be one of di first groups to export Afrobeats to other parts of di continent. Dem sell-out live performances sake of dia energetic break-dance routines. Dem bin also get collaborations wit performers like Diamond Platinumz from Tanzania and American superstar Akon. For 2011, dem sign wit Akon Konvict Muzik label and a year later dem gbab one distribution deal wit Universal Music Group. Dem also get award as MTV Africa Artist of di Decade for 2015 and win di Best Group title three times. Afta di two split dem go on solo careers as Mr. P (Peter) and Rudeboy (Paul) but none of dem reach di levels of success dem achieve as P-Square." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59337398 +politics Bayelsa Governorship Elections: 30 political parties sign peace accord "Ova 30 political parties for Bayelsa state south of Nigeria, sign peace accord to agree say no violence before, during and after di election. All di political parties wey go participate for di Bayelsa govnorship election including Peoples Democratic Party and All Progressive Congress follow sign di peace accord. National Chairman for Independent National Electoral Commission INEC, Prof. Yakubu Mahmoud for stakeholders meeting with all di political parties wey dey participate for di Governorship election give assurance say dem don implement 12 out of di 14 point plan for di election as di law tok. Im add say all non-sensitive materials don land dia office for Yenagoa and dem don share am according to local goment, wards and polling unit but di sensitive materials dey for Central Bank of Nigeria and dem go deliver am dis weekend. Di smart card readers sef dey configured and dem go deliver dem togeda with all di oda sensitive materials. ""Make I emphasise say e dey compulsory to use smart card reader for voter accreditation and authentication,"" im tok. With less than 9 days to Bayelsa govnorship and state assembly elections, Inspector General of Police Mohammed Adamu cut warning give officers say make dem no compromise diasefs but make dem secure election materials and arrest any pesin wey dey share money or do vote buying. ""No let any politician tempt you. If you do, you go enta problem. As una dey do una work, if you see any pesin wey dey share money, abeg mobilise and arrest di pesin. E dey illegal. Make sure say peace and security dey di polling unit."" IGP Adamu tok dis one for Police Headquarters Yenagoa as im visit Bayelsa give assurance say pipo go dey safe to cast dia votes come 16 November, 2019. Di IGP say dem go send 32,000 policemen to make sure say di election dey peaceful, free and fair. IGP Adamu come add say all di welfare package for officers wey go dey duty dem don already pay am into dia account to cover all di days dem go dey for election duty." https://www.bbc.com/pidgin/world-50343155 +health Coronavirus: Nigeria goment go close Lagos, Abuja International airports ontop 10 new cases of COVID-19 Nigeria goment don announce say dem go close Murtala Muhammed International Airport for Lagos, and Nnamdi Azikwe International Airport for Abuja from Monday. For statement wey di regulator, Nigerian Civil Aviation Authority, NCAA tok, di closure of di two biggest airports for di kontri dey in addition to di three other international airports for Kano, Enugu and Port Harcourt wey don alredi close today. Director-General of NCAA, Capt. Musa Nuhu say di closure go last till April 23. Oga Nuhu add say emergency and essential flights go dey in operation for di two airports within di period. E say di measure dey very important as di Coronavirus pandemic dey increase. Alredi Nigeria confam 10 new cases today, and di total number of confamed cases now don reach 22. Di NCAA say domestic flight operations go continue normally in all airports for di kontri. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51978747 +sports Klopp want Liverpool full points if dis match wit Man United postpone "Jurgen Klopp believe say Liverpool gatz dey awarded di points if dia Premier League match against Manchester United dey postponed sake of fan protests. One game between di sides for May 2021 gatz dey rearranged after home fans march waka go Old Trafford to protest di Glazer family ownership of di club. Anoda protest dey planned before Monday match, leading to fears say wetin last year fit repeat. ""Plans for di game no dey happen? Yes, going home on di bus,"" Klopp yarn. ""I really hope e no go happun but if e occur I tink na we get di points. ""We get noting to do wit di situation and if di supporters want di game not to happun, den we no go fit just rearrange di game again and fit am in somewia inside a very busy season. ""Pipo tell us say we dey fine, we go-go dia and play di game hopefully and go home. ""But in a situation like dis, always di oda team suppose get di points unto say dem get notin to do wit am and dem don prepare for am."" Last year match, di first in Premier League history to dey postponed unto fan protests, for dey played behind closed doors unto di coronavirus pandemic. However, thousands of United supporters bin gada outside di ground for di hours before di planned kick-off before around 200 fans break into di stadium. Wen e dey asked about di planned protests against di Glazer family, United oga Erik ten Hag say: ""I go fit only say di owners want to win - and di fans, we want dem to dey support di club. ""I can understand sometimes but I no dey dat old inside di club wey be say I fit see all di backgrounds, but we gatz to be unified and fight togeda."" Both teams go dey search for a first win of di season, as e be say Liverpool draw dia first two games and United start wit back-to-back defeats. Ten Hag want to see more ""fighting spirit"" from im side wen dem take on dia rivals on Monday. ""E dey start wit yoursef,"" im tok. ""Act as a team. Follow di rules and principles and work hard, as hard as you fit maximise. If you do am, then you get confidence. ""Na one week wey dey normal as a manager. Say you see a game, you get a plan, a way of play and den you check how di game waka.\n""And then you analyse and you see wetin dey wrong and wetin good. Now obviously, a lot don go wrong [in di 4-0 defeat to Brentford]. ""But wetin I go say na say you no get tok about anytin wen di attitude no dey right.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c065lly88y5o +politics Wike on Obaseki: Gov Nyesom Wike don pull out of Edo PDP reconciliation ahead of 25 June govnorship primary "Govnor Nyesom Wike of Rivers State don pull out of di reconciliation efforts for Edo State Chapter of Nigeria main opposition People's Democratic Party(PDP). Dis dey happun barely a day to di important 25 June party primaries to choose who go fly di flag of PDP for di 19 September, 2020 govnorship election wey go happun for di Southern Nigerian State. Di reconciliation committee suppose settle all di differences between party members, including tori of court ruling wey say make di Edo State Govnor Godwin Obaseki wey just port from di ruling All Progressives Congress (APC) enta PDP, no contest di Govnorship primary election.Gov. Wike tell tori pipo for in Port Harcourt say some members of di National Working Committee(NWC) of PDP na wetin him call 'sychophants and tax collectors' wey no dey tok truth. Im say; ""instead of di NWC to carry evribodi along for Edo state, dem dey use media to blackmail me."" ""I tell dem say for Edo State, we must handle di issue carefully and carry evribody along. Dem must respect human beings and no behave like tax collectors.""Dem say because order come from a Federal High Court in Port Harcourt, then I dey responsible. Me wey don get sleepless nights to resolve di issue for Edo state. Di Governors of Edo, Adamawa, and Delta states, know wetin I don do to resolve issues for Edo state.Because of dis senseless accusation, I don pull out of Edo State settlement. ""My integrity matter to me."" Wike tok. Di Rivers Govnor come warn say if PDP no dey careful, di crisis for di All Progressive Congress (APC) go be a child's play, come add say im wan concentrate on di development of Rivers State. Meanwhile Peoples Democratic Party (PDP) don clear throat come outside tok say no member of dia National Working Committee (NWC) sponsor any media publication to rubbish di pesin of Rivers State Govnor Nyesom Wike. Di party describe di kain publication wey Govnor Wike dey tok about as handwork of external forces and enemies of di PDP wey dey gree-die on sow seeds of bad belle within di party. Di NWC for statement wey Kola Ologbondiyan, di PDP National Publicity Secretary release just hours afta Govnor Wike comment, tok say dem wish to place on record say none of dia members don act like a ""tax collector"" in whatever meaning di term represents, either in di process leading to di Edo primary election, or any oda state." https://www.bbc.com/pidgin/53157259 +entertainment BBNaija Lockdown Reunion: Highlights from first episode of di BBNaija lockdown reunion "Di season 5 housemates of di popular reality TV show, Big Brother Naija don come back to di house for di reunion show. First episode of di show air on Thursday wit only 18 housemates out of di 20 on screen for di first day of di reunion. Erica and Kaisha no join for di first episode but di host of di show, Ebuka say di two housemates go join in later. Di Big Brother Naija show na popular Nigeria reality TV show wia organisers keep contestants for one house for 10 weeks wit tasks, to battle for millions of Naira price. Organisers say dis reunion na anoda chance for di housemates to clear di air and express dia real feelings towards each other afta di gbas-gbos wey happun during di real show. Di housemates come in red carpet entrance to di reunion. Dem drop each of dem from dia chauffeured car and dem waka di red carpet. One of di housemates, Tolanibaj say she come di reunion to ""come speak her truth not to change di narrative, but explain di narrative wey some pipo don attach to di Tolanibaj name."" She also mention say she go confront di pipo wey she need confront. For Kiddwaya, im say im no really get issue with any of di housemates. Nengi say e dey nice to see di housemates again ""a lot don happun since di show and hopefully everybody fit find a common ground"". Lilo wey be one of di first set of contestant to comot from di house say she dey excited about di reunion as she bin no get enough time to spend wit di rest of di housemates ""I hope say we go dey able to tok things out and be friends"" Other housemates also share dia expectations from di show wit Ebuka. Organisers say di four things to expect from di Lockdown Reunion na For di first time for di Big Brother Naija Reunion history, every single Housemate for di Lockdown Season go attend. E get more love triangles and squares than wetin pipo fit imagine According to Big Brother, di biggest clash come from two supposed friends and di first reconciliation come from two longtime enemies. Di show host, Ebuka mention say e get more than one few jaw dropping moments and even di Housemates dey shocked to find out how much dem no really sabi each other. BBNaija Reunion Show na part of preparations for di commencement of another season of di reality show, and fans go once again get to see dia favourite 'Lockdown geng'." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57522963 +entertainment Adekunle Gold and Simi: Five Nigeria celebs wey do secret wedding Rumour dey fly upandan for social media about Nigeria celebs Adekunle Gold and Simi unto say dem marry today for secret wedding. Even though two of dem neva come out to tok weda na true or not, one source wey close to di couple tell BBC Pidgin say, true-true di wedding happun and na 300 pipo show to follow dem share dia joy. BBC never fit independently confam dis tori. Secret wedding common for among Hollywood celebs but dis days Naija celebs too don follow dey hide do dia weddings too. Famous Nigerian Afro pop star D'banj A.K.A Koko master, bin hide im marriage to im girlfriend Lineo Didi Kilgrow. D'Banj marry im wife on 2 July, 2016 for small ceremony. Afta her relationship wit Super Eagle star Ikechukwu Uche scata, she jejely go America go do secret wedding. Uche marry her Puerto Rico boyfriend on 16 May 2012. Na for December 2015, popular Musician Dija quietly do her wedding but pipo no sabi say she don marry until July 1, wen she come out to tell di world say she don marry and she get baby boy. Ogbonge Nigeria model and Miss World 2001, Agbani Darego, waka go Morocco marry Ishaya Danjuma di son of billionaire Theophilus Danjuma, for April 2017. Tori be say na only 35 pipo dem invite for di wedding. Former Nigeria international footballer Joseph Yobo marry 2008 Most Beautiful Girl in Nigeria, Adaeze Igwe for midnight ceremony for Jos, North Central Nigeria for 2010. For 2014 dem list Adaeze as di number four most beautiful Africa sportsman wife. https://www.bbc.com/pidgin/tori-46806497 +sports Arsenal vs Man United prediction: Preview of Gunners and Red Devils battle for fourth place Di Premier League go return dis weekend afta some clubs play dia midweek matches. Na five games dey on Saturday but di top match na di one between Arsenal and Manchester United. Arsenal wey dey play for home fit increase Man United problem as di Red Devils don continue to struggle for di league. United poor outing against Liverpool wey dem lose 4-0 expose di club poor form dis season. On Wednesday dem announce di appointment of Ajax boss Erik ten Hag as dia new manager from next season - e no clear weda dis announcement fit boost di morale of di squad ahead of di clash wit Arsenal. Arsenal forward Alexandre Lacazette fit start di game wit Man United afta Mikel Arteta bring am as late substitute for game against Chelsea. Dis na afta di striker bin suffer from Covid-19. Gunners right back Takehiro Tomiyasu fit also return to di squad afta weeks of absence due to calf injury wey im suffer for January. Manchester United midfielder Paul Pogba go miss di rest of di season wit di calf injury wey e sustain during di club defeat to Liverpool on Tuesday. Cristiano Ronaldo, Raphael Varane and Scott McTominay all dey available to play. Arsenal bin lose three straight games before dia redemption for Stamford Bridge on Wednesday but di gunners dey unbeaten for dia last three Premier League home games against Manchester United. Dem win two, draw one. Arsenal don record 32 points for Emirates Stadium. Only Liverpool (42) and Manchester City (38) don win more games for home. Meanwhile, Manchester United don lose four of dia last seven matches in all competitions. However, dem don win all dia five Premier League fixtures dis season against dia closest rivals for fourth place - wey be Arsenal, Tottenham and West Ham United. Di Red Devils don concede 48 Premier League goals dis season. Afta dia poor run of games, Arsenal look good wit wetin dem show against Chelsea for mid-week. Though United no turn up for Anfield, dia fans go dey expect better response on Saturday especially wit di return of Cristiano Ronaldo. But football sabi pesin, Mark Lawrenson believe say both Arsenal and Manchester United no get any surprises to show for dia match. Prediction: 1-1 https://www.bbc.com/pidgin/sport-61193763 +politics D-Day for Kogi Elections Ova di next 48 hours (or more depending on how di election go) 24 political parties go contest for di 2019 Kogi governorship election. Even though 22 oda parties dey for di race for who go be di next govnor of di state, di All Progressives Congress (APC) and di People's Democratic Party (PDP) na im pipo see as di main rivals. Di two parties dey often dominate local newspaper headlines and conversations on social media. Yahaya Bello - APC: Di youngest govnor for Nigeria dey seek for second term for office. Di 44 year old rise to leadership carry plenti tok of godfatherism and allegation of supernatural forces wen im enter power for 2015. Today election go be di first real test of im popularity and if di pipo go accept am. Workers salary wey im owe and cases of insecuiry fit don afect im first term but pipo dey wey believe say e go improve on im short coming if im get second chance. Musa Wada - PDP: Like di APC, di PDP governorship primary for Kogi carry katakata follow body. One death, raid by jaguda pipo and wuruwuru eventually see Wada become di party flag bearer. Following im elder brother, Idris footsteps, Musa an Igala don focus im campaign for di eastern senatorial district wia e come from. Di Engineer say if im get di pipo mandate, im go pay up salaries, take beta care of pensioners while e go diversify source of state revenue. But dis na di same promises di pipo don hear since democracy return for 1999. Natasha Akpoti -SDP: Other contesters nickname her di spoiler, Natasha fit prove to be pesin wey fit spoil work for Yahaya Bello. She no dey shy to go toe to toe wit di govnor wey she accuse of high handedness and no sabi di work. She and Bello come from Okene and fear dey say she fit take some of di votes for di area come spoil di govnor hope to clear di votes for im home. Di 39-year-old lawyer don visit courts plenti times to ansa if true true her candidacy pure. She and di SDP dey back on di ballot paper andno dey happy sa pipo dey call dem freshmen for Kogi politics after dem contest for di KogiCentral Senatorial District seat early dis year. Di senator no be contestant for di election but im influence on wetin dey happun for di state don see am get more followers for social media platforms. Although im contest e loss for PDP primaries, e look like say oga Dino dey okay wit Wada campaign. Di 45-year-old Melaye and im senior, Sam Adeyemi go kontinu to show dia power for Lokoja, Ajaokuta and Kabba/Bunu wey be hot battle grounds wey di candidates go like win. Kogi East na di largest region for di state. E get voting population of 804,715 registered voters of 1,646,350 total registered voters for di state. Kogi East na also di home to most local council areas for di state - 9 of 21 Total registered voters for Kogi Central wia Bello come from na 409,120 wit 5 local councils. Kogi West get total of 432,515 registered voters wit 7 local councils. E dey early to assume say di candidate wey win di east go become di govnor. About 35, 00 policemen, qwy no include oda security agencies na im dem don deploy go Kogi state. According to di Independent National Electoral Commission (INEC), polling stations go open for accreditation and voting go start from 8am to 2pm. If you join di queue before 2pm, dem go accredit you and allow you to vote. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50440719 +politics Edo Assembly crisis: You dey look for trouble - Oshiomhole warn Obaseki "Adams Oshiomhole, di National Chiarmo of All Progressives Congress (APC) open warning na for Govnor Godwin Obaseki of im home state of Edo. Kasala burst afta nine out of 24 members elect Speaker plus oda principal officers for Edo State House of Assembly on Monday night leaving out 15 odas. ""Edo own na 9.30 pm, wey be unholy hours. Dat na night hours. Di working hours for parliament dey inside di rules of di parliament. E no dey for any pesin hand to change those rules only properly constituted parliament fit change di rules as dem dey,"" Oshiomhole add. Meanwhile, di APC Chairman for Edo State Nigeria, Anselm Ojezua, bin don tell BBC say im hapi with di way di House of Assembly mata take happun on Monday, wia Edo lawmakers take oath of office for night. True true, di law say na one third of di lawmakers need to dey present so as to form quorum and out of 24 lawmakers, 10 dey present on di night of 17 June when di inauguration happun. According to Ojezua, since dem meet di requirement, dem no break any law for di inauguration of di 7th assembly for di state. ""I no tink say wetin di 7th Assembly do for Edo state break any law. Di constitution say one third of members suppose present... and di mace. So everything wey happun on dat night dey politically, legally and constitutionally correct."" Former Edo State House of Assembly member, Osaro Obazee agree with APC national position, say as for am dem no do di right tin. Oga Obazee say for mata wey three of di nine pipo wey do di inauguration don come out to say na force dem force dem go, and some of dem na lawyers and go school well and dis one make di [inauguration] dey wrong"". ""Di court go torchlight di mata of wetin go happun next and do di needful... because I know say dis mata go end up for court,"" Obazee tok. Local tori bin report say one member of di House of Assembly bin tok for video say im find imsef for di inauguration under duress - na im bin say im correct mind no dey for wetin im do." https://www.bbc.com/pidgin/tori-48693428 +entertainment Mrs Sri Lanka Beauty Pageant: Winner of Mrs Sri Lanka 2019 comot di crown of 2021 winner say she no fit be queen - See why "Small drama happun for Sri Lanka biggest beauty pageant as di 2021 winner of di beauty pageant suffer head injuries sake of fight wey happun for stage. Beauty queen Pushpika De Silva win di ""Mrs Sri Lanka"" title for one ceremony dem show on national TV on Sunday. E no tey afta, di 2019 winner comot Ms De Silva crown, say she no fit collect di title because she don divorce. Ms De Silva bin later collect di price afta di pageant organisers confam say she no be divorcee. Judges name Ms De Silva di 2021 winner for di Mrs Sri Lanka final for one theatre for Colombo on Sunday night. But di 2019 winner, Caroline Jurie, remove di crown from Ms De Silva head say one of di pageant rule na only pipo wey marry no be divorcee fit compete for di competition. ""Rule dey wey no dey allow women wey marry later divorce take part for dis competition, Sake of dat, I dey go crown di pesin wey be second,"" Ms Jurie tell di audience. She put di crown for di second runner up head wey make Ms De Silva cry as she waka comot di stage. Di organizers don tok sorry to Ms De Silva and dem clear di mata say she neva divorce her husband only say dem separate. For inside one Facebook post, di beauty queen say she go hospital go treat di wound she get for head afta di kasala wey burst. She say she go take legal action for di bad way dem take treat her. ""I be un-divorced woman,"" she write. ""A true queen no be woman wey dey snatch anoda woman crown but na woman who for secret dey seet anoda woman's crown!"" Di national director of Mrs Sri Lanka World, Chandimal Jayasinghe, tell BBC say dem go return di crown Ms De Silva on Tuesday. ""We dey disappointed,"" he add join say: ""Di way Caroline Jurie take behave for stage na disgrace and di Mrs World organisation don begin torchlight di mata."" Police don question Ms Jurie, wey be di current holder of di ""Mrs World"" title, as well as Mr Jayasinghe, on top di mata. Di Mrs Sri Lanka World beauty pageant na ogbonge contest for di kontri. Di prime minister wife dey among di guests for di ceremony." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56652654 +entertainment James Brown: Instagram delete 'James Brown' account afta gbas-gbos wit Bobrisky "Nigerian personality James Brown don react afta Instagram delete im account from dia platform few hours afta im clash wit Bobrisky anoda popular cross dresser. "" I dey unbreakable if you pursue me comot from Instagram I go come Youtube, if you pursue me from Youtube I go enta Twitter if you pursue me from Twitter I go enta Snapchat if you pursue from me from dia I go enta Tik-tok"". na wetin Brown tok Social media site Instagram bin delete Brown account afta e do video wey e claim say e receive call from Bobrisky wey accuse say im dey copy im content as cross dresser. Brown allege say ""Bobrisky threaten to kill am"". Im add say I just dey dress like woman for fun only for Instagram but for real life I dey dress like man so Uncle Bob no see me as threat. Dis dey happun days afta Instagram delete one Nigeria musician and entertainer, Tunde Ednut page for di second time for dia platform wey get one million followers. ""I dey sorry if I fall some pipo hand tonight"". na wetin im tell im 3.6 million followers for im page. Bobrisky post two messages but e no call James Brown name inside di post. For di fist post e say ""I love all of una and I always dey ready to take correction when i do wrong"". E end di post wit plenty love emojis. Den e post anoda one wia im say ""I never report anybody Instagram page before since im join IG. Pray say make nobody accuse of wetin you no know dis dis year, dat prayer deep"". James Brown, na Nigeria popular cross dressers wey im real name na Obialor James. Na 2018, Brown blow for Nigeria afta im viral video wey e tok say 'Dey didn't caught me' enta internet. Brown say im find out at di age of 12 say im get HIV and na from birth e take cath di disease." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55687011 +entertainment Seyi Shay, Victori Kimani, Tiwa Savage: 'Beauty salon beef video' & di real 'Tiwa' profile Tiwa Savage and Seyi Shay video wey show dem beef and throw insult at each oda na im don flood Nigerian local tori. Di beauty salon video gbas-gbos dey make pipo tok about di two female top Nigerian musicians. No be today wen Afropop singer, Seyi Shay rumoured rivalry with Nigerian 'Queen of Afrobeats' Tiwa Savage start. But Seyi don tok am before say she no see Tiwa as a rival. So BBC Pidgin don torchlight how di two celebs don grow dia careers recently. Tiwa Savage burst for di Nigerian music scene for 2011 to catch dia attention with di gbedu wey dem call Kele Kele Love. E feature love song wey Nigerians bin enjoy, she follow dat one wit plenti love gbedu wey include Love me, Love Me, Ife Wa Gbono. And she also sing 'Don't Leave without my heart' wey she do with producer, Don Jazzy. Then for 2013, she cari her tent pitch am for Mavins Records wia she drop two ogbonge albums Once Upon A Time for 2013 and R.E.D for 2016. Na also for dia she get di name of Queen of Afrobeats. Outside music, she bin feature for di Health TV Series wey dem bin call Sugar and also be activists against rape cases dem. For May, 2020, Mama Jam-Jam (nickname of her pikin Jamil) port comot from Mavins to join Universal Music Group on an exclusive music deal wey go see her new music enta international market. And true to di contract, wen for August she drop her fourth studio album, Celia. E see two songs for di album, Dangerous Love and Korobba peak for No 2 and No 9 for Billboards. So far, Tiwa Savage don collabo with stars like Wizkid, Davido, Sam Smith, Beyonce, and Omarion. Seyi Shay real name na Deborah Oluwaseyi Joshua Odedere. She be Nigerian based singer, song writer, recording artist and performer. Her song Seyi or Shay wey she release for 2015 blow her into limelight. Shay sign her first record deal with No Apology. For 2006, she form girl Band, Boadicea. Di band scata for 2008. Tori be say she enta Nigeria for 2011 an na time she sign record contract with Flytime Records. Hit songs like Right Now, Yolo Yolo, Gimme Love, Irawo, make her popular. Nigerian Idol bin reveal her as one of di judges wey go dey for di 2021 show. Di singer, wey start to dey sing at age six, considers herself fortunate to don collect inspiration from fellow artiste, Sound Sultan. Kenyan Star, Victoria Kimani na pesin wey blow for di Nigerian scene wen she do di remix for Ice Prince hit song, Oleku remix. Then for November 2012, she join di record label, Chocolate City. And na for inside di record label, she comot with di album, Safari for 2016 before she comot di label for 2017. She don win di Nigeria Entertainment Award for African Female Artist of di Year (Non Nigerian) for 2018. She don work with stars like Busta Rhymes, Cassie among odas. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57418132 +entertainment Cardi B say why she reconcile with Offset for di second time "Rapper, Cardi B don tok why she return back to her husband, Offset afta she file divorce case for court one month ago. She tok dis one afta she announce say she don reconcile with her husband of three years. She say na because dem don siddon tok about am. Pipo start to call out her relationship say she dey ""mentally abusive relationship"" afta she tok for instagram live say she don reconcile with her pikin papa. But she hit dem back say, ""Twitter pipo be like, 'you dey mentally abusive relationship, make we save you' and go dey like 'but I go fit sleep with am sha, because me I need sex'."" She explain say, she and Offset bin tok about dia relationship and tins wey dem wan change for dia. She explain say her and Offset dey normal relationship and with ups and downs wey dem go need face because dem marry young. Rumours say dem don reconcile comot afta dem spend Cardi B birthday party togeda and im buy am Rolls Royce. She later comot to say she don reconcile with am because she ""bin dey miss my best friend."" Na wen di kata-kata start to dey burst about di kind of relationship wey she get with her husband, na im make she say make pipo no chook mouth because ""dem no dey live with me for my house."" Di mata of her divorce comot afta she file di case, even as she say pipo for no sabi wetin bin dey happun if court no release am, tori be say she neva comot am. Dis na di second time, di couple three year marriage don threaten to fall apart afta 2018, wey Cardi B leave Offset on top cheating accuse. Cardi B and Offset marry for private ceremony for September 2017. However, Cardi B don warn pipo say make dem stay out of her personal mata, say di craze pesin wey she be before, na di same craze wey she still get till now." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54584644 +sports Chelsea vs Liverpool highlights: FA Cup final penalty shootout see Liverpool become champions Liverpool don win dia second title of di season as dem defeat Chelsea 6-5 on penalties. Dis na di second time dis season wey Chelsea go lose on penalties to di side from Merseyside afta dem lose di Carabao Cup final for February. Di Blues match Liverpool during regulation time but Alisson save from Mason Mount kick and Tsimikas conversion of im own kick guarantee Liverpool dia second trophy dis season. Liverpool enjoy di better chances during di final, di outstanding Luis Diaz and Andrew Robertson hit di bar. Liverpool now go get even more believe say dem fit win di quadruple as dem still dey in di race to win di league and also dey di final of di Champions League wia dem go play Real Madrid. Di defeat na serious blow for Chelsea and manager Thomas Tuchel to lose in dis manner yet again as dem too bin get chances - Marcos Alonso hit di post and also see Alisson save im shot well - but dem become di first side to lose three successive FA Cup finals. Chelsea defender Alonso go take di first kick, im score Chelsea 1-0 Liverpool Milner step up for Liverpool. Im score Chelsea 1-1 Liverpool Azpilicueta na im go take next for Chelsea. Im miss Chelsea 1-1 Liverpool. Thiago send Mendy di wron way. Chelsea 1-2 Liverpool. James score for di Blues. Chelsea 2-2 Liverpool. Firmino na im be next, im run stop run again before im shoot di ball past Mendy wey touch am small Chelsea 2-3 Liverpool. Ross Barkley blast im kick past Alisson. Chelsea 3-3 Liverpool. Now na di turn of Trent Alexander-Arnold, im send Mendy go di wrong way as im score. Chelsea 3-4 Liverpool. Jorginho turn don reach, im score. Chelsea 4-4 Liverpool. Mane dey up next, if im scor Liverpool don win di cup. Mane miss against im Senegal teammate. Chelsea 4-4 Liverpool. Ziyech don step up to take for Chelsea. Di Moroccan blast im kick past Alisson. Chelsea 5-4 Liverpool. Diogo Jota for Liverpool, score! Di Portuguese shoot right Mendy dive left. Chelsea 5-5 Liverpool. Alisson save Mason Mount kick. Chelsea 5-5 Liverpool. Now Liverpool need to score to win, Tsimikas to take, im score. Liverpool win FA Cup 6-5 on penalties Chelsea make two substitutions before second half extra-time start. Loftus-Cheek and Azpilicueta don come on for Pulisic and Chalobah. 106 mins - Meanwhile Liverpool don restart di game. 108 mins - Chelsea want penalty as dem believe say Alexander-Arnold pull Ziyech back. Do ref wave play on. 111 mins - Liverpool take off Robertson, Kostas Tsimikas don come on. 115 mins - Di tempo of di game don drop as both teams don dey run out of gas. 119 mins - Lofrus-Cheek wey just come on go need leave di pitch as Ross Barkley don replace am. 120 mins - Penalties na im go decide dis game as e don finish Chelsea 0-0 Liverpool during regulation time. 91 mins - Chelsea go get us underway for di first half of extra-time. If e end goalless afta extra-time di game go enta penalties to decide di winner. Liverpool make substitution - Van Dijk off, Joel Matip on. 95 mins - Chelsea players and coach want penalty afta Pulisic go down inside di box wit claim say Matip foul am. Di referee wave play on as VAR no call im attention to di incident. 98 mins - Roberto Firmino don come on for Diaz. 99 mins - Mount produce good moment but im final shot go di war most of di shot don go today - ova di bar. 105 mins - Some of di players look like say dem don taya but second of ext-time still dey for dem to play. 46 mins - Liverpool restart di second half and straight from dia Chelsea win di ball come create good chance. First Alonso drag im shot from di right hand side wide den Pulisic test Alisson wit right foot shot. Di Blues don start di second half well, 48 mins - Hit di bar! Alonso again go close to score wit freekick wey hit di crossbar. 51 mins - Liverpool full backs combine, Robertson fail to connect wit Alexander-Arnold cross. 52 mins - Diaz go close wit shot from outside Chelsea box. Di two teams don begin create chances. So far Chelsea don take six shots (two on target), while Liverpool don shoot 10 times (only one on target). 60 mins - E be like nobody wan score today. Jota dis time shoot im shot wide of di post anoda good chance to open di scoring. 63 mins - Liverpool win back-to-back corner kicks but both times notin come out of dem as Chelsea handle di threat well. 65 mins - Thiago pick out Keita wit looped pass, di Guinean shot no trouble Menday as im catch am well. 66 mins - Substitution: Chelsea bring on Kant for Kovacic as coach Thomas Tuchel make im first sub. 68 mins - Anoda shot off target from Christian Pulisic. Di forward try to take James cross first time but im shoot wide. 69 mins - Diaz try to bend im righ foot shot past Mendy di ball go ova. 74 mins - Liverpool make dia second substitution as James Milner don replace Naby Keita. 77 mins - Reece James receive yellow card for late foul on Thiago. 83 mins - Diaz don hit Chelsea post! Di Liverpool forward collect pass from Mane, settly imsef well before im strike hit di post. 84 mins - Liverpool hit di post again, incredible! Dis time from Robertson wey connect wit Milner cross. 85 mins - Hakim Ziyech don come on for Romelu Lukaku. 90 mins - Referee don add three minutes before stoppage time. If e end goalless, dem go play extra time. Full time - Chelsea 0-0 Liverpool. 1 min - Lukaku and Chelsea don start di final for di sunny Wembley stadium. 4 mins - Poor clearance from Mendy see Liverpool quickly work di ball ova to Luis Diaz wey see im cross-shot go past everyone. Trent Alexander-Arnold retrieve di loose ball come send left foot cross back in wey Salah head ova. 8 mins - Mendy produce good save to deny Diaz from opening di scoring as im save di Colombian shot wit im legs. Diaz beat di Chelsea high line to run ontoo Alexander Arnold pass but im fail to punish di Chelsea defence. 12 mins - Chelsea look like dem dey boot as Liverpool players dey run di show. Dis time a couple of blocks deny di Reds from finding di target. Good defending by Chelsea. 17 mins - Kovacic try to break into Chelsea box wit good run wit di ball but Thiago bring am down. Alisson comfortably catch di freekick wey Alonso tak wit im left foot. 22 mins - Pulisic go close to give Chelsea di lead. Di American run onto Mason Mount cut back but im fail to direct di ball goalwards as e roll harmlessly wide. 25 mins - so far di game dey goalless but Liverpool just camp for Chelsea half. 28 mins - Liverpool goalkeeper Alisson spread imsef well like butter inside bread as im stop Marcos Alonso from scoring. Di Spaniard leg brush di goalkeeper wey later need treatment. 30 mins - Alisson dey okay and di game don restart. Soon afta, Mo Salah go down and di doctors dey attend to di Egyptian. 33 mins - Salah no go fit kontinu, Diogo Jota don replace am as Liverpool make forced substitution. 40 mins - Mistake by Van Dijk see Chelsea Mount di ball off am. Di midfielder pass di ball to Lukaku wey try to send am back to Mount but Liverpool intercept and clear di ball. 42 mins - Konate try im luck from outside di box, im shot rise high and wide of Mendy goal. 45 mins - Jota miss good chance to give Liverpool di lead. Di substitute meet Robinson cross but loop di ball ova. 45+1 mins - Now na Lukaku turn to blaze im shot ova afta Jorginho knack am fine pass. We don enta four minutes added time. Half time - Chelsea 0-0 Liverpool. Chelsea XI: Mendy, Chalobah, Silva, Rudiger, James, Jorginho, Kovacic, Alonso, Mount, Pulisic, Lukaku Liverpool XI: Alisson; Alexander-Arnold, Konate, Van Dijk, Robertson; Keita, Henderson, Thiago; Salah, Mane, Diaz https://www.bbc.com/pidgin/sport-61451539 +sports Joe Erico: Interesting facts about former Super Eagles goalkeeper and assistant coach wey die at age 72 "Nigeria football federation general secretary Mohammed Sanusi don pay tribute to di former senior team goalkeeper and one-time assistant coach of Super Eagles, Joe Erico wey die at di age of 72. Family sources say Oga Erico bin complain of body pains and bin dey collect treatment for malaria, before dem find im deadi bodi ontop bed on Thursday. ""Erico dey among di best international goalkeepers for Nigeria wey serve di kontri wit favour and diligence na wetin oga Sanusi tok. Dis dey come days afta former minister/Chairman, National Sports Commission, Hon. Bala Bawa Ka'oje die at di age of 60 years. Dem born Joseph Bassey Eric for Odukpani local goment area for Cross River State, south- south of Nigeria. Im make im debut for di then Green Eagles of Nigeria for di Africa Cup of Nations qualifying match against Zambia for Lagos for July 1973 (wey Nigeria win 3-2), Oga Erico na im keep for all Nigeria six matches for di 1976 Africa Cup of Nations for Ethiopia, where di Eagles finish third - and na di first time di kontri win medal for AFCON. Im nickname na 'Jogo Bonito'( wey mean Beautiful Game) dem call am dat name because of di way im team dey play. Na Erico (alongside late Amodu Shaibu and late Stephen Keshi) do di rescue job for Nigeria wen things been bad during di 2002 FIFA World Cup finals under Dutchman Johannes Bonfrere. With three matches to go and a must-win game for all, di three of dem deliver and qualify Nigeria for Korea/Japan. Dem also lead di Super Eagles team to bronze-medal finish for di 2002 Africa Cup of Nations finals for Mali. With im death on Thursday morning, e mean say all di members of dat coaching crew now don die." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55769067 +health "Cameroon ""schools resumption date"" afta Covid-19 and de rules weh schools get for respect" For Cameroon nursery, primary secondary and high schools go di jump back wit joy for school for Monday 5. Universities go follow for October 15. School pikin dem di turn back afta eight months weh goment bi decide for lock schools, borders, take oda actions for slow de spread of Coronavirus for march 17. But e good for note say students for exams classes bin go back for school for July, learn write certificate exams, first school leaving certificate exams and general certificate of education exams for secondary and high schools. Schools for Cameroon get for respect all barrier measures, disinfect schools and class rooms, wash hands wit soap, wear masks and keep social distance. Weti bi de rules for learn wit Corona for corner? According to Laurent Serge Etoundi Ngoa, minister of basic education nursery and primary schools classes one -three no go wear mask. De reason na say deh still small for take care for dia masks but de teachers get for wear. Goment di encourage distance learning, though e nova bi clear how e go work, di focus for work books for homework especially for rural areas. School go get for reorganise dia timetables and goment intend for put oda measures for short and long term. Minister for secondary education, Pauline Nalova Lyonga don stress make school no put more dan 50,000 pikin dem for one class. Schools wit classes weh deh get more dan 50 pikin dem go get two shifts, some for morning and odas for afternoon. But e nova bi clear how dis go fit work for private school weh deh no get de means. Goment di bring new way for learn from far, 'Distance Learning' for secondary schools. Jacques Fame Ndongo for minister of higher education say washing hand points dey for plenti places for campus, priority for research for get solution for coronavirus pandemic For dis 2010/2021 school year, de only new tin na say goment di invest on na for put centres for distance learning get material, partner wit national TV for teach school pikin dem from distance. Manaouda Malachie, Health Minister, say Covid-19 nova finish as Cameroon still get 740 active cases wit 30 for ICU as of September 30 from total of 20,924 confirmed cases. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54388623 +entertainment 'Pipo say make our papa go do DNA test' - meet unidentical twins Kehinde and Taiwo Apelehin """Wen pipo bin see our picture for social media, we bin get different comments: 'like weda dem change us for hospital or make our papa go check di DNA o!"" Dis na some of di reaction wey Kehinde and Taiwo Apelehin don ansa since dia mama welcome dem into dis world 25 years ago. Di twins wey come from Lagos trend for Nigeria afta dem share dia birthday foto on social media wey make pipo shock say dem no look alike. Taiwo and Kehinde say dis no be di first time dem dey get dat kain reaction from pipo even when dem dey young. ""Wen pipo first see us, dem go first doubt say we be twins. Dem no dey believe am."" Taiwo Apelehin dey live with albinism, while Kehinde dey dark skinned. ""Wen pipo ask us why we no look alike, I go tell dem make dem ask God"" Taiwo tok for siddon interview with BBC Pidgin. Kehinde say wen dem post dia foto for social media, dem get comments like ""make una papa go do DNA, una sure say dem no exchange una for hospital""? She say dis comments sometimes dey make her laugh. ""Some pipo also message us say dem get twins pikin wey be like us and dis one make me happy well-well say e get pipo wey dey look up to our tori"", Kehinde tok. Taiwo say wen dia mama born dem, doctors tell her say na lack of melanin make one of dem dey live with albinism. Melanin na natural skin pigment. Hair, skin, and eye color for pipo and animals mostly depend on di type and amount of melanin dem get. ""Wen she first born us and realise say one of her pikin white, she first shout say, wetin make my pikin white o"" ""She bin no like albino from start, she dey always run from dem"" She explain say di doctors bin tell her mama dat time say e no dey abnormal to born twins like dat. ""Dem just advice her make she no expose.me to sun unlike Kehinde sake of my skin color"" ""As you see us so, my mama no dey segregate us, she dey baff us with the same soap, take care of us the same way, na wetun help my skin be dat."" Taiwo tok. Di unidentical twins say dem still get wetin make dem look alike Taiwo and Kehinde say even as dia colours dey different, dem still get physical features wey pipo go use sabi say dem be twins. ""Wen pipo look us well-well, dem go say our nose dey same o, some go even agree say we get di same kain body structure,"" dem tok. ""Dem go always be like, even you look dem well, you go sabi say dem be twins"". As pipo dey see dem differently, question dia DNA, di twins say dis one no dey encouraging for dia parents dem. ""If you see twins like us, make pipo no dey tok bad about dem, na God create us"" Taiwo add say even parents wey dey raise twins wey dey unidentical make dem no dey partial with dem. ""Make parents no dey like one pass di oda, make dem dey treat dem di same way""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60764302 +politics State of Emergency: Why President Muhammadu Buhari fit declare am for Anambra state "Di security situation for Anambra state fit make dem declare state of emergency, Abubakar Malami, na so Nigeria Minister of Justice tok. One month to di governorship election wey go hold on 6 November, Anambra state don see series of violent attacks from jaguda pipo. Apart from di Independent National Electoral Commission (INEC) concern about di conduct of election for di state, di murder of Dr. Chike Akunyilli, husband to late Dora Akunyili former Director General of National Agency for Food & Drug Administration (NAFDAC) cause change of security strategy for di state. Ontop di election mata, Ipob don declare say di November 6 govrnorship election no go hold. But INEC don tok say di election go hold regardless. Govnors and leaders for di southeast region summon emergency meeting wia dem ask federal goment to stop activities of di Indigenous People of Biafra (Ipob). ""Na we be di chief security officers for our various states and we understand wetin dey happen. We know say na our pipo dey kill our pipo and dem come begin kill security men, dem begin burn houses and den stop pipo from moving freely,"" Chairman of di South east Governors forum, Dave Umahi tok. Federal goment position ontop situation for Anambra state Afta di weekly federal executive council meeting for State House Abuja, di Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami, drop hint sey goment fit declare State of Emergency for Anambra state. Oga Malami tell State house tori pipo sey goment no go fail to take precaution to ensure ""democratic order"" for di state. According to di Minister ""Wen dem attack our national security and di sanctity of our constitutionally guaranteed democracy dey threatened, no possibility dey ruled out. As goment we get responsibility to ensure di sustenance of our democratic order. We get responsibility to provide security to life and property. So, wetin I dey tok be sey we fit declare state of emergency, wia we confam say di Anambra state goment don fail to restore order. State of emergency na declaration wey goment dey make to suspend some normal functions of executive, legislative and judicial powers for any state. Di declaration fit suspend certain normal functions of goment, fit alert citizens to change di way dem dey run tins or fit authorise goment agencies to implement emergency plans plus limit or suspend civil liberties and human rights. Di need to declare state of emergency from different situations like armed action against the state by internal or external elements, natural disaster, civil unrest, epidemic, financial or economic crisis or general strike. According to Section 305 of di Nigerian 1999 Constitution (as amended) e give power to di President to proclaim state of emergency. ""Di President get power to issue a proclamation of a state of emergency only wen di federation dey at war, dia is actual breakdown of public order and public safety for any part of di federation wey require extraordinary measure to avert danger,"" some part of di constitution tok. Di constitution add say apart from di declaration ""di President go transmit copies of di Official gazette wey contain di proclamation of di emergency to di President of di Senate and Speaker of di House of Representatives wey siddon to approve di proclamation."" Di state of emergency comment by di Minister of Justice Abubakar Malami no dey go down well wit di Anambra state goment. Don Adinuba, Commissioner of Information for Anambra State say e dey ""outrageous"". Adinuba sey ""Anambra neva experience di kain violence wey dey happen for some parts of Northern Nigeria like Kaduna, Borno, Zamfara and wia bandits dey always attack."" Political parties wey dey participate for di 6 November governorship election including All Progressives Grand Alliance (APGA) and Peoples Democratic Party (PDP) no also like di idea." https://www.bbc.com/pidgin/media-58826150 +politics Supreme Court: Emeka Ihedioha, Abdulahi Ganduje, Aminu Tambuwal, four oda Govnors go know dia fate today Nigeria supreme Court dey continue hearing of di election appeal of seven governors on Tuesday. Di Supreme Court suspend di judgement for seven Govnors wey win di March 2019 govnorship election for Nigeria go on Tuesday sake one of di seven Judge wey dey sit for di cases fall sick. Govnors wey dey affected na Emeka Ihedioha (Imo), Bala Mohammed (Bauchi), Simon Lalong (Plateau), Samuel Ortom (Benue) and Aminu Tambuwal (Sokoto). Security reports say already, red alert dey for some states like Sokoto wia di state police commissioner don send 1000 men on standby to prevent any kasala wey fit gas. Meanwhile on Monday wen di court bin plan to give judgment, crowd of supporters of di seven govnors don pack go tanda for Supreme Court domot to give support to dia governors. Many of dem bin wan enta di court room but di plenti security wey tanda for dia no gree dem and dis come lead to some delay before court start di case. Report say already red alert dey for Sokoto North West Nigeria wey be Tambuwal state and dem don send 1000 men to prevent any kasala wey fit gas. But afta everi-everi don dey sorted out, di court adjourn di case, Di court come begin work but di Chief Justice Tanko Muhammed again tell di court to go for a brief break so dat one of di judges wey make up di seven man panel go fit take im drugs as e no dey feel too well. Before then, di court bin first gbab break for some minutes afta di hearing begin because of di crowd and di noise level inside di court. Justice Tanko bin say make dem suspend di case as e be say security operatives fail to control di crowd and di noise level inside di court. As part of ways to reduce di court, di CJN come direct lawyers wey dey represent di parties make dem no appear with more than five lawyers. Dey come tell politicians wey no be parties for any of di appeals to leave di courtroom as police pipo come later send one dog to help drive di crowd. Afta dat di court come resume proceedings. Dis appeals na different candidates wey dey no dey happy with di March 9 election, carry am go court Di court dey hear di appeals wey di governorship candidates carry come, 10 months afta di elections wey happun for di seven states We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51066685 +sports Champions League round of 16 draw 2021/22: Uefa Champions League last 16 teams "Paris Saint-Germain go face Real Madrid for di pick of di 2021/22 UEFA Champions League round of 16 draw. Dis na afta di dem redo didraw for UEFA headquarters in Nyon, Switzerland on Monday. Title holders Chelsea go play French side Lille for di Champions League knockout stages took place for a second time. Who go play who for di UEFA Champions League last 16? Salzburg (AUT) vs Bayern (GER) Sporting CP (POR) vs Manchester City (ENG) Benfica (POR) vs Ajax (NED) Chelsea (ENG) vs LOSC Lille (FRA) Na Atlético (ESP) vs Manchester United (ENG) Villarreal (ESP) vs Juventus (ITA) go play Inter (ITA) vs Liverpool (ENG) get match Paris Saint-Germain (FRA) go face Real Madrid (ESP) Di first legs go take place for 15/16 and 22/23 February, 2022. Wit di return-legs wey dey scheduled for 8/9 and 15/16 March. Di draw for di quarter-finals and semi-finals go hold on Friday 18th of March, 2022. Quarter-finals, first legs (5/6 April). Quarter-finals, second legs (12/13 April). Semi-finals, first legs (26/27 April). Semi-finals, second legs (3/4 May). Final (28 May). UEFA declare di initial draw void because of technical problems and apologize. Inside di original draw, Manchester United ball bin pull out of di pot against Villarreal. But dem no dey ineligible to face each oda as dem bin don dey di same group - one eventuality Uefa say di technology suppose to prevent. Last season Europa League winners Villarreal na im instead bin dey paired with Premier League champions City. Further confusion appear to occur when United bin no dey from di pot of possible opponents for Atletico Madrid, and Liverpool dey included instead. However, United fit play di Spanish side and Liverpool no fit, as e be say dem don progress into di knockout stage from di same group. Uefa tok inside one statement: ""Following a technical problem wit di software of an external service provider wey instructs di officials as to which teams dey eligible to play each oda, a material error occur inside di draw for di Uefa Champions League round of 16. ""As a result of dis, di draw don dey declared void and go dey entirely redone. Two seeding pots dey formed: one get eight group winners di (seeded ones) and di oda of di eight runners-up (unseeded teams). No team fit dey drawn against one club from dia group or any side from dia own association. Seeded group winners dey drawn away for di round of 16 first legs and at home for di return matches. You gas know say no away goals Di away goals rule don dey cancelled. If di tie dey level for after 180 minutes, e go enter extra time. If di teams still no dey able to separate after anoda 30 minutes, di tie go enter penalty shoot-out. Each club fit register maximum three new players for di remaining matches by midnight CET on February two 2021. Players dey allowed to don play for anoda club for di UEFA Champions League or UEFA Europa League restrictions dey on di number of 'List A' players. Uefa want pipo wey dey seek more information on dis to check Article 46 of di regulations to know more." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59642051 +sports Barcelona hijack Raphinha deal from Chelsea? Barcelona ready to make offer wey reach £60m for Leeds United winger Raphinha, 25, as dem wan beat Chelsea to di Brazil international's signature. (Times) Chelsea dey make progress in dia talks to sign Matthijs de Ligt, 22, but Juventus want the Netherlands international's £102m clause to dey activated. (Telegraph) Richarlison don complete im Tottenham medical in Brazil ahead of finalising a £60m move from Everton.(Sky) Manchester City will go only sell defender Nathan Ake, 27, if dem get replacement with the Netherlands international linked with return to former club Chelsea. (Manchester Evening News) Juventus want Liverpool and Brazil forward Roberto Firmino, 30, in a swap deal for dia France midfielder Adrien Rabiot, 27. (Calciomercato) Manchester United don join Newcastle for battle to sign £50m-rated French defender Benoit Badiashile, 21, from Monaco. (Nice-Matin) West Ham United dey wait for decision from former United player Jesse Lingard. The Hammers feel they have made a good offer (Sky) Bayern Munich don reject a third bid from Barcelona for Poland striker Robert Lewandowski, 33, with di German champions wanting £43m. (Bild) Leeds United and England midfielder Kalvin Phillips, 26, go do medical for Manchester City on Friday before completing a £45m move to the Premier League champions. (Sky Sports) https://www.bbc.com/pidgin/articles/cllj04g940zo +sports African team squads for Qatar World Cup 2022 Na Five days remain for di 2022 Fifa World Cup wey dey happun for Qatar to start. Football fans around di world don dey catch di World Cup fever. As belle dey sweet di kontris wey qualify, pepper body dey worry some big kontris wey miss out. Nigeria, Cote D'ivoire, Algeria and Egypt no qualify for Africa, Italy, 2018 hosts Russia and Norway wey get di hottest striker for Premier league now Erling Haaland no go for Europe. Africa na one of di controversial continents wey football fans get mixed feelings about, sake of say dem get plenty stars, ogbonge players wey dey make name for dia clubs, but yet dem neva win di World Cup before. Even though fans dey enjoy African teams wen dem play for di biggest international football fiesta for di world, di same football fans no dey expect too much from dem. Africa fit make progress pass di semi-final stage with di squads wey dey represent di continent? Dis na question pipo dey ask Ghana, Tunisia, Cameroon , Senegal and Morocco.s. Meanwhile, make we torchlight dia final squads. As Nigeria no qualify for di World Cup West Africa fit don ready to give arch rivals Ghana all di support. Afta Ghana qualify for dia first World Cup for 2006, dem become di third African nation to qualify for di quarter finals for di 2010 edition for South Africa. Ghana dey Group H wit Portugal, Uruguay, and South Korea Ghana Squad\nGoalkeepers: Lawrence Ati Zigi, Nurudeen Manaf, Ibrahim Danlad.\nDefenders: Tariq Lamptey, Alidu Seidu, Alexander Djiku, Gideon Mensah, Dennis Odoi, Daniel Amartey, Mohammed Salisu, Joseph Aidoo, Baba Abdul Rahman.\nMidfielders: Andre Ayew, Mohammed Kudus, Thomas Partey, Elisha Owusu, Daniel Kofi Kyereh, Abdul Salis Samed.\nForwards: Osman Bukari, Williams Inaki, Jordan Ayew, Daniel Afriyie Barnieh, Sowah Kamal, Antoine Semenyo, Kamaldeen Sulemana, Abdul Fatawu Issahaku. Some of di players dey happy well well afta dem see di final list on Monday, 14, November. Dem tok ontop social media say belle dey sweet dem to be part of di team At di moment, Senegal na one of di big teams for Africa especially wit dia ogbonge star player Sadio Mane. Evribodi eyes dey on di former Liverpool star wey win di 2021 Africa Cup of Nations. Senegal dey for Group A wit hosts Qatar, Ecuador, and Netherlands Senegal squad Goalkeepers: Seny Dieng, Alfred Gomis, Edouard Mendy. Defenders: Fode Ballo-Toure, Pape Abdou Cisse, Abdou Diallo, Ismail Jakobs, Kalidou Koulibaly, Formose Mendy, Youssouf Sabaly. Midfielders: Pathe Ciss, Krepin Diatta, Idrissa Gana Gueye, Pape Gueye, Cheikhou Kouyate, Mamadou Loum Ndiaye, Nampalys Mendy, Moustapha Name, Pape Matar Sarr. Forwards: Boulaye Dia, Famara Diedhiou, Bamba Dieng, Nicolas Jackson, Sadio Mane, Iliman Ndiaye, Ismaila Sarr. Tunisia don go World Cup five times. Most of dia players dey play for dia local football league. Dem dey Group D wit France, Australia, and Denmark. Tunisia squad Goalkeepers: Aymen Dahmen, Bechir Ben Said, Aymen Mathlouthi, Mouez Hassen Defenders: Wajdi Kechrida, Mohamed Drager, Dylan Bronn, Nader Ghandri, Bilel Ifa, Yassine Meriah, Montassar Talbi, Ali Maaloul, Ali Abdi Midfielders: Ghailene Chaalali, Aissa Laidouni, Eliyes Skhiri, Hannibal Mejbri, Ferjani Sassi, Mohamed Ali Ben Romdhane Forwards: Wahbi Khazri, Youssef Msakni, Taha Yessine Khenissi, Issam Jebali, Seiffedine Jaziri, Anis Ben Slimane, Naim Sliti. Morocco squad Goalkeepers: Yassine Bounou, Munir Mohamedi, Ahmed Reda Tagnaouti. Defenders: Achraf Hakimi, Noussair Mazraoui, Jawad El Yamiq, Romain Saiss, Achraf Dari, Yahia Attiyat Allal, Badr Benoun, Nayef Aguerd. Midfielders: Sofyan Amrabat, Azzedine Ounahi, Abdelhamid Sabiri, Selim Amallah, Yahya Jabrane, Bilal El Khannous. Attackers: Hakim Ziyech, Zakaria Aboukhlal, Sofiane Boufal, Youssef En-Nesyri, Ez Abde, Amine Harit, Ilias Chair, Abderrazak Hamdallah, Walid Cheddira. Cameroon squad Goalkeepers: Devis Epassy, Simon Ngapandouetnbu, Andre Onana. Defenders: Jean-Charles Castelletto, Enzo Ebosse, Collins Fai, Olivier Mbaizo, Nicolas Nkoulou, Tolo Nouhou, Christopher Wooh. Midfielders: Martin Hongla, Pierre Kunde, Olivier Ntcham, Gael Ondoua, Samuel Oum Gouet, Andre-Frank Zambo Anguissa. Forwards: Vincent Aboubakar, Christian Bassogog, Eric-Maxim Choupo Moting, Souaibou Marou, Bryan Mbeumo, Nicolas Moumi Ngamaleu, Jerome Ngom, Georges-Kevin Nkoudou , Jean-Pierre Nsame, Karl Toko Ekambi. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cl4gnk8x54eo +sports Leeds United vs Arsenal: Martinelli lead di way as Gunners thrash Leeds 4-1 Arsenal record comfortable 4-1 win over Leeds United as dem capitalise on di host poor display to put more grip on dia top-four position. Gabriel Martinelli score twice before goals from Bukayo Saka and substitute Emile Smith Rowe ensure Arsenal cruise to victor despite say Leeds pull one back from Raphinha. Leeds bin start di game without some of dia key players wey dey out due to injury. Di Gunners capitalise on dia absence and di fact say some teams no play dis weekend to go four points clear for fourth position on di table. Di spread of di Omicron variant of Covid across UK lead to postponement of six Premier League games. Arsenal produce superb first half as di scoreline for increase wella but impressive performance by Leeds goalkeeper Illan Meslier, wey make fine saves to deny Saka, Alexandre Lacazette, Thomas Partey and Kieran Tierney. 46mins: Arsenal begin di second half di way dem start di first wit pressure on Leeds Unite. Dem get two corners inside di opening minutes but Leeds clear di two. 50mins: Two incidents of potential red cards. First Xhaka go scot free afta im step on Raphinha. Di referee no give am card but later im hand Joe Gelhardt yellow card as im tackle Tomiyasu. 57mins: Stuart Dallas collect yellow card afta im pull back Arsenal defender Takehiro Tomiyasu. 63mins: Tomiyasu look like say im don get injury. Cedric Soares don come on to replace am. 67mins: Saka play one-two wit Martinelli but e come later shoot wide. 72mins: Leeds get dia first shot on target from Tyler Roberts. Aaron Ramsdale comfortably save am. 74mins: Penalty! Leeds United win penalty afta Ben White foul Gelhardt inside di box. Raphinha send Ramsdale di wrong way. Leeds 1-0 Arsenal. 78mins: Subtitution - Arsenal bring on Emile Smith Rowe for Saka while Leeds send on Sam Greenwood for Mateusz Klich. 81mins: Leeds make anoda substitution as Odegaard receive treatment. Liam McCarron come on for Summerville. 84mins: GOAL! Arsenal extend dia lead. Substitute Smith rowe volley in Odegaard through pass. Leeds United 1-4 Arsenal. 86mins: Granit Xhaka collect yellow card for time wasting. Later Leeds defend Koch also receive yellow for push on Martinelli. 90mins: Just like di first half referee add three minutes injury time. Full time: Arsenal win comfortably in di end as dem hand Leeds dia third straight defeat. E finish Leeds United 1-4 Arsenal. 1min: Leeds take di opening kick of di first half and immediately pressure Arsenal to concede corner kick. From di corner Raphinha head di ball over. 3mins Chance! Meslier produce not one but two good saves from Arsenal. First from Lacazette and den anoda one from Partey. 5mins: Wow! Di game start so fast wit those two early chances but tins don calm down small. 11mins: Gabriel Martinelli run down di left and pull di ball back into di box. Martin Odegaard step over am... but nobody dey behind am except Leeds defenders. 16mins: GOAL! Martinelli score to give Arsenal di lead. Leeds fail to clear di ball as Martinelli pounce on di loose ball to score. 24mins: Tierney test Leeds keeper wit shot from di left side. From di corner Leeds break quickly but Raphinha no fit convert as im shoot wide. 28mins: GOAL! Martinelli again. Leeds lose the ball again as Xhaka slide through pass to di Braillian wey calmly chip di goalkeeper. Leeds 0 - 2 Arsenal. 33mins: Chance afta chance afta chance na im Arsenal don get for dis match as dem dey dominate Leeds. 42mins: GOAL! Bukayo Saka increase Arsenal lead wit deflected shot wey Leeds goalkeeper no even bother. 45mins: After three minutes of added time, referee end di first half. Arsenal lead 3-0. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59712357 +politics Rochas Okorocha: EFCC sama former Nigerian governor wit 2.9 billion naira fraud allegations Di Economic and Financial Crimes Commission EFCC don charge former govnor of Imo state, Rochas Okorocha, wit allegation say e joinbodi wit politicians and five companies to steal 2.9 billion naira from public funds. According to EFCC, Okorocha wey also dey serve as Senator allegedly divert di moni between October 2014 and February 2016 from di Imo State Government House account and Imo State Joint Local Government Project account. Okorocha never respond to di allegations. EFCC tok-tok pesin, Wilson Uwujaren confam di tori to BBC Pidgin say di commission file di 17 charges on Monday for Federal High Court, Abuja. Di charges dey come hours wen oga Okorocha declare im intention to run for di office of di president for 2023. No be only oga Okorocha EFCC dey accuse, dem also name odas wey allegedly involve for di matter. Oga Okorocha bin win di Imo state gubernatorial election for 6 May 2011 and dem vote am again for second term for 11 April 2015. Di former govnor now dey represent di Imo West Senatorial District for di red chamber. Senator Okorocha na di founder of Rochas Foundation, one charity organization wey build schools and dey give children schorlarship for school for Nigeria. Di Nigeria corruption police don dey drag Okorocha tey-tey on top corruption mata. For September 2019, Di EFCC claim say dem don get court order to seize some of im property like one 16 blocks of flats, eight bungalow multi million naira estate, hotel two schools, shopping plaza, super market, hospital and four vehicles, most of dem dey di state. On 13 April, 2021 di Nigeria corruption police operatives bin arrest Okorocha wey represent lmo West senatorial District on for im Unity House office for Garki, Abuja. For dat time dem accuse am of embezzlement and misappropriation of funds but dem later release am days later. https://www.bbc.com/pidgin/tori-60196343 +sports Naomi Osaka quit French Open: Piers Morgan, Serena William, Stephen Curry, odas react "Many celebs don comot to support Japanese tennis player Naomi Osaka decision to step down from di French Open. Naomi Osaka decision be say she no go do press conferences for matches. Osaka tok dis one for inside statement wey she release on Monday. She say she bin send message to di organizers if Roland Garros to apologize on top all di gbas-gbos her decision bin cause. She also tok say, later on she go like discuss with di Tour on ways wey dem fit make tins to dey beta for players, press and fans. For di statement , she reveal say she don dey deal with depression since 2018 and she also get social anxiety. Dat na why press conferences dem dey hard for her. Tennis Star, Serena Williams, wey follow play for di French Open bin also stand gidigba for Osaka back. She say she wish say she fit hug am on top say she know how e dey be, as she don dey that kain position before. Former World Number one, Billie Jean King also hala for Tweet say, make pipo give Osaka space. Fellow Tennis Stars, Rafael Nadal and Novak Djiokovic, howeva, don point out say although e dey important to tok about mental health, media runs dey very important for her job. E dey important to note say, for Osaka win against Patricia Maria Tig, she bin tok with di media on di court but she no gree go for press conference and na wetin cause all dis gbege. Oda celebrities don comot to tok on top di Naomi Osaka mata. Basketball star, Stephen Curry comot to praise Osaka for her decision wey e call ""taking di high road wia powers no dey protect dia own"". Controversial TV Host, Pier Morgan also chook mouth for di mata wia he call Naomi say she be ""little madam"" wey dey childish. But no be only Osaka don get wahala with talking with di media. Tori be say Olympic legend, Michael Phelps bin get wahala with di media from 2000, wen im say dem bin ask am weda im get girlfriend o don kiss at 15 years old and di questions make am uncomfortable. NFL Star, Cam Newtons don dey accused say im dey like to dodge to do press conferences for im team most especially if dem loose matches dem." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57307281 +sports South Africa president pledge equal pay for Banyana Banyana afta Women Africa Cup of Nations win """You deserve equal pay for equal work wey you do."" Dis na di words of South Africa President Cyril Ramaphosa as e promise to give equal pay to di kontri women football team. E tok am for one event on Wednesday, wen im roll out red carpet for di Bayana Bayana football team afta dem return from Morocco wia dem gbab dia first Africa Cup of Nations. Im beg di kontri ministers of finance and sports to up di bonus. President Ramaphosa say dem deserve to get paid as much as dia male counterparts . South Africa beat tournament host Morocco 2-1 for dia final on Saturday, 23 July for Rabat. Dis na di first continental title for di Banyana Banyana side afta five initial final defeats. Di victory don cause public debate around equal pay for di kontri, afta report first say di players go receive less money for prize bonuses dan dia male colleagues wen dem reach di quarter-finals of di men tournament for 2019. ""Our hearts dey filled wit pride. E dey burst wit great deal of joy,"" Ramaphosa tok during di reception for di goment Union Buildings for di capital. ""We need to give added remuneration to dis young women wey don make our kontri so proud. But as dem do so, we must make sure say we comot di whole process of unequal pay from we system."" Ramaphosa say make di kontri outlaw pay discrimination and start programme to bridge di gender pay gap. ""You deserve di best. Welcome home, champions of Africa. You na di Golden Girls of our kontri. You be di queens of Africa,"" im tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cprl2nw78g7o +politics Voters registration for Ghana 2020 election: What you need to know about di exercise Electoral Commission of Ghana as part of efforts towards free and fair elections dey compile New Voters Register ahead of de 2020 General Elections. De registration process wey start from today, June 30, 2020 to August 6, 2020 from 7.00am to 6.00pm. If you be Ghanaian wey you want participate in dis year General Elections, dis be eleven facts about de voter registration exercise de Electoral Commission of Ghana put out. Electoral Commission say in order to be able to vote in de polls you for fit meet de following criteria. What dis dey mean be say if you no dey meet any of eligibility criteria dem you no fit register your name for de elections. 1. Citizen of Ghana 2. 18 years and above 3. You for have sound mind 4. You for be resident or you for dey belong to electoral area 5. No law wey dey in force for stop you from registering Other facts wey you for know about de registration be de documentation to prove your nationality. 6. Passport 7. National Identification Card (NIA Card) 8. In case where you no get passport and NIA Card, you for get two 9. guarantors who register under dis recent registration exercise make dem who go confirm your citizenship as Ghanaian. Finally these be key facts you for know about de how and where you go fit register 10. Registration exercise go happen based on Cluster System. Each Cluster go have 5 registration centres wey e go happen in 5 Phases. Each phase go last three days. 11. De team go move from one phase to de other until dem finish all de 5 phases. Wey dem go use 3 days do Mop Up Exercise after de main Registration be over. So dis be eleven key facts you for know about de ongoing Ghana voters' registration exercise. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53240782 +sports Arsenal vs Chelsea: How to watch, predictions for Premier League London derby match "Arsenal don already lose to one London team dis season - newly promoted Brentford. So how di Gunners go cope against European champions Chelsea on Sunday? ""A lot of pipo go dey expect Chelsea to beat Arsenal but I feel say di game go tough pass as many pipo think am."" Na so BBC football sabi pesin Mark Lawrenson tok. Checkout Lawro predictions for all 380 top-flight matches dis season, against different-different guests. For dis weekend fixtures, him dey up against The Wombats drummer Dan Haggis. Di Wombats' new song If You Ever Leave, I'm Coming With You na one of di Hottest Record for di World on BBC Radio 1 Future Sounds show dis week. Dia fifth album Fix Yourself, Not The World dem go release am next year and tori be say dem go begin dia UK tour for April. Also Dan na die hard Everton fan wey dey ""reluctantly optimistic"" say di club fit recapture dia glory days for 1980s. So for di Ogbonge match dis weekend see Lawro and Dan prediction Cable television channel DSTV, go carry di match live for Supersports. E go dey interesting to see how Chelsea new £97.5m striker Romelu Lukaku go fit into dia team, and whether Arsenal go fit stop am. Mikel Arteta neva take charge of many Gunners games in front of full stadium and, di last time im did, tori be say im no bin dey under dis kain pressure him dey face now. We no know which strikers dey available for Arteta, but I feel say him go play safe anyway rather than trying to attack Chelsea. Wetin im no need for dis situation na to lose two games back-back matches, especially to two London clubs, which for me go make things worse. Lawro prediction: 1-1 Dan prediction: I feel say Chelsea go do really well dis season and I notice di Match of di Day pundits think di same. 1-2" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58293443 +politics Buhari on South South Governors meeting: President Buhari explain why e snub stakeholders meeting for Port Harcourt "Di presidency don explain give why no delegation from di Federal goment attend di meeting wit south-south govnors for Porthacourt. Prsident toktok pesin, Garba Shehu for statement say di delegations no fit come di meeting sake of di emergency security meeting wey president Muhammadu Buhari summon and not out of disrespect for di leaders of di region. E further explain give say di Chief of Staff to the President, Professor Ibrahim Gambari, ministers and heads of security and intelligence agencies bin don ready to travel to Port Harcourt before dem ask dem to stay back to attaend di security meeting. Oga Garba yarn give say goment bin reach out to di host of di meeting through some channels to inform am about di new development Di emergency security meeting wey hold on Tuesday na sake of di security situation for di kontri wey don dabaru afta di endsars protest bin happun and dat di issue don affect every part of di kontri including south- south. Oga Garba say goment dey ready to hear from leaders, stakeholder and young pipo from south -south region on top wetin dey happun for di kontri and dat sake of dis, dem go consult wit di leaders dem so dat dem go come up wit new date wey dem go hold di meeting. South South Governors don ask di Federal Goment to apologise to di region for cancelling one important stakeholders meeting wey suppose hold today for Port Harcourt. Di Presidency bin fix di meeting wit Governors and oda leaders of di region to discuss plenty national issues wey affect di region and oda matters wey happen after di EndSars protests but di meeting no hold. Delta State Governor, Ifeanyi Okowa wey preside over di session say dem shift di time of di meeting two times from 11am to 1pm on Tuesday sake of excuse say President Buhari bin dey meet wit di Director of di Department of State Services DSS and Inspector General of Police wey suppose be part of di South South meeting, but im later get call from di Chief of Staff to di President, Agboola Ibrahim Gambari to cancel di meeting. Governor Okowa say dem dey very disappointed say Federal Goment fit treat di region like dat come add say na disrespect to di region. ""We dey call for public apology not for di Governors alone, we ask for apology because no be we call for dis meeting, na di Presidency naim call di meeting. Dem change di time last night, we understand come tok to our pipo. Some of us no sleep wia we dey try to put tins togeda. So we don get very bad start and we dey send dis message to di Chief of Staff to di President. As a region, we deserve unreserved apology, particularly to our traditional rulers and leaders for dis zone wey include our Christian leaders, opinion leaders, our women, our youths and di Governors of di zone wey di pipo elect, and dat na di least we expect for us to accept to reconvene dis meeting again."" Oda leaders like di former President of di Movement for di Survival of Ogoni Pipo MOSOP, Ledum Mitre, Ms Ann Kio Briggs, President of Ijaw Youth Congress, Peter Igbifa also add dia voice say di Federal Goment don take di South South region for granted and dem no value di region at all." https://www.bbc.com/pidgin/54989901 +politics Isa Pantami comments and why Nigeria goment stand by Minister of Communication "Nigeria presidency don describe di call for President Muhammadu Buhari to remove di kontri Minister of Communication and Digital Economy, Ali Isa Pantami from office as ""cancel campaign"". Di presidency through statement wey senior media aide to di President, Garba Shehu sign say di Minister dey ""currently, subject to 'cancel campaign' wey pipo wey want di removal of di minister dey instigate."" Dis comments by Garba Shehu dey come afta days of pressure by some Nigerians wey don call on di minister to resign or make di president comot am from office sake of e past extreme religious views. Trends for Twitter with hashtags #Pantamimustgo and #Pantamiresign na im come lead to Garba Shehu inside statement. Shehu for di statement say pipo: ""no really care wetin he [Pantami] fit or fit no don tok some 20 years ago: dat na merely di instrument wey dem dey use to attempt to ""cancel"" am. But dem go profit if we stop am from making decisions wey go improve di lives of everyday Nigerians."" Im add say: ""Di Minister don, rightly, apologize for wetin im tok for early 2000s. Di views dey absolutely unacceptable then, and go dey be equally unacceptable today, if im repeat am. But im no go repeat dem..."" Di call for di minister to resign begn after Peoples Gazette comot one old video of im past views wia im bin sympathetic wit terrorist organisations. Pantami initially deny say im hold any extremists views and call di reports defamation of character by pipo wey dey against im policies as di minister of communication and digital economy. Later, for one interview wey Daily Trust report, di minister acknowledge im past views but tok say im don since renounce those radical comments. ""Some of di comments I make some years ago wey dey generate controversies now bin dey based on my understanding of religious issues at di time, and I don change several positions wey I take in di past based on new evidence and maturity,"" na so Daily Trust bin quote wetin di minister tok when im answer questions during e daily Ramadan lecture for Al-Noor Mosque. ""I bin dey young when I make some of di comments; I bin dey university, some of di comments I make am when I be teenager..."" W Di statement by di Presidency add say di Minister ""don dey lead di charge against illegal data deductions and pricing; im don revolutionize di government virtual public engagement to respond to Covid-19 and save taxpayers' money; im don establish ICT start-up centres to boost youth entrepreneurship..."" Nigeria presidency claim say newspaper editors bin reject attempt to financially induce dem to run smear campaign against minister by some ICT companies. Allegation wey BBC no fit verify. But oga Garba Shehu tok say di government now dey investigate di veracity behind di claims of attempted inducement. Finally di statement tok say President Muhammadu Buhari administration ""stand behind Minister Pantami and all Nigerian citizens to ensure dem receive fair treatment, fair prices, and fair protection in ICT services."" ""The administration stands behind Minister Pantami and all Nigerian citizens to ensure they receive fair treatment, fair prices, and fair protection in ICT services.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56853897 +politics Children of top Nigerian politicians wey win for di primary elections Pipo across Nigeria dey continue to tok about di primaries of di top two political parties wey happun recently for Nigeria. Di opposition Peoples Democratic Party, PDP don conclude everything including presidential primaries while di ruling All Progressives Congress, APC still get dia own presidential convention to come on di 6th - 8th of June. For di primaries wey hold last week across both parties, delegates elect dia flagbearers both for the govnorship seats and di national assembly. While di primaries see some upset and shock losses by some popular politicians, e also introduce some wey pipo fit say be new faces. Some of dem be children of popular politician wey wan follow in di footsteps of dia parents. Umar wey many sabi as Abba na pikin to current Kano state Govnor Abdullahi Umar Ganduje and na im win APC ticket for House of Reps to represent Dawakin Tofa, Rimin Gado and Tofa constituency.\nUmar wey im papa name after am win di Thursday primaries unopposed as di oda candidate Junaidu Yakubu step down for am.\nUmar Ganduje na engineer wey also be business man. Idris na pikin to former govnor of Oyo state Ajibola Ajimobi and in law to Kano state Govnor Abdullahi Ganduje as e dey married to Fatima Ganduje.\nNa Idris win APC ticket to contest for Ibadan South-West II State Constituency.\nLate Ajimobi pikin win di primaries unopposed as di oda candidate step down for am. Bello na pikin to current Govnor of Kaduna state Nasir El-Rufai and na im win di APC ticket for house of reps for Kaduna North constituency.\nBefore now, Bello bin dey serve as legislative aide to Kaduna central Senator and Governorship aspirant Uba Sani. Eriathake na pikin to former Govnor of Delta state James Ibori and na she win ticket to contest for House of Representatives for PDP for Ethiope Constituency.\nEriathake get 46 votes for di re-run wey hold to defeat her closest challenger Ben Igbakpa wey get 22 votes. Abba na pikin to former Zamfara state Govnor Ahmad Sani Yarima and na im win House of Reps ticket for Bakura/ Maradun federal constituency.\nDi pikin of di govnor wey first introduce Sharia during im time as govnor first contest for 2019 under APC unfortunately for am court dismiss di election den. Usman na pikin to former Govnor of Zamfara state Mamuda Aliyu Shinkafi and na im win di ticket to contest to represent Shinkafi constituency for House of Reps under APC.\nUsman papa serve as deputy govnor for eight years under Govnor Sani Ahmad Yarima before serving four years as govnor imself between 2007-2011. Surajo na pikin to di Chief Justice of Nigeria Ibrahim Tanko and na im win di APC ticket to represent Bauchi North for senatorial election wey go happun next year.\nDi 40 year old defeat incumbent senator Adamu Bulkchuwa to emerge as winner. Former Head of State Sani Abacha, piki Muhammad na im win PDP ticket to contest as govnor of Kano state for next year election.\nDi business man beat im closest challenger Jafar Sani 736 to 710 to clinch di ticket.\nDis go be di third time wey Muhammad go contest e go dey hope say e go dey lucky dis time. Mustapha na pikin to former Jigawa state Govnor and Minister of Foreign Affairs Sule Lamido and na im be PDP governorship candidate for Jigawa after e win primaries.\nMustapha go battle with di present deputy govnor of di state Umar Namadi as di two top candidates for next year elections. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c87l2722g3eo +sports Man United vs Liverpool: Prediction for di Premier League game and where to watch Ground go shake on Sunday October 24, 2021 wen Manchester United jam Liverpool for Old Trafford for Premier League. Di two teams dey come into dis game afta dia midweek Champions League victories. Liverpool beat Atletico Madrid 3-2 for Spain and United beat Atalanta wit di same score line. Dis na everything you need to know ahead of di league match between di two most successful clubs for England. You see Manchester United performance wey dem come back from two goals down against Atalanta and win 3-2 on Wednesday na di summary of how di team be under dia manager Ole Gunnar Solskjaer. Dem fit play badly for some games and di next minute dem dey hard to stop. Dat na wetin BBC football sabi pesin Mark Lawrenson tok If to say United lose dat game den e for be bonus for Liverpool but, instead di two teams moral dey high going into di weekend match. Although United fit dey under more pressure to get positive result, because dem don drop points for each of dia past three league games, but draw no go be bad result for either camp and dat na wetin I dey go for. Liverpool no go change di way dem dey play - dem no fit. And na di reason wey I feel say United go dey defensive because, if dem dey open, you go fear di worst for them. Lawro prediction: 1-1 Di game go start by 4:30pm West African time and e go dey live for Supersports on DSTV if you dey reason to watch am for Nigeria and Ghana. Di two clubs don meet 201 times, United don win 81 times against Liverpool. And dem don share points on 58 occasions and Liverpool don win 68 times. Last season, di two teams face each oda twice for Old Trafford. for January, di Reds beat di Merseyside club 3-2 for di Emirates FA Cup, na Mason Greenwood, Marcus Rashford and Bruno Fernandes score di goals. But for league, na Jurgen Klopp men na im celebrate di three points, Dem win 4-2 for Theatre of Dreams. Cristiano Ronaldo fit make im first United appearance against di Anfield club since 2009 on Sunday. Ronaldo get good record for dis fixture. In eight appearances against Liverpool before im move go Real Madrid, Ronaldo don score twice and assist two too. Di two goals came for im last two matches against Liverpool for Old Trafford. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59020513 +entertainment Jodie - Kuchi-kuchi singer say strangers bin advise her to kill her son as she cry out for help "Popular Nigeria music artiste Jodiegreat don cry out say make pipo help am wit moni to take care of her pikin wey get special needs sake of Cerebral palsy disease. Jodiegreat become popular for 2010 afta she drop one hit single 'Kuchi kuchi'. For one Instagram post on Wednesday, Jodie bin write one long tori wia she take make di appeal and also tok about her child condition. For di post, she bin write say, she no be lazy pesin. ""I bin sing one song, Kuchi Kuchi for 2010, wey Kings and Queens don listen to and enjoy. I dey use di soft spot wey dat song fit don create to make dis appeal. ""For di past six years, I don hawk beaded jewellery for office like Total, Noah's Ark, DDB etc. I don sell hair care products, I don beg. I don borrow. Nigerians dey kind"". She add say true-true , she be 'NOBODY', but dey inspired, years ago to sing one song wey still dey till date. ""Who sabi? Maybe di reality be say Kuchi Kuchi no be for my popularity, but to answer to di silent cry of mothers wey born special needs children. She also add say maybe di reality be to speak for di blood of di special needs children don spill for secret by helpless mothers wey no sabi wetin else to do. ""I know dis, sake of some strangers don advise me to kill or abandon my son, sake of say children like dat, dem dey send am to swallow moni, she tok"". She add say her moni don dey swallowed and her friends don abandon her, sake of say she be beggar. ""My debts dey new every morning. But I be mama wey go rather die first before her son no eat. Jodie add say, special needs children no dey eat normal food. Dem need plenti medical, emotional, etc care. Special need children require di help of well established world-class organisations, because no be dia fault say dem born dem dat way. Di Delta state born singer bin don dey struggle to deal wit her pikin condition since she born am. For 2017, she bin grant TV interview to explain wetin she dey go through since she born her pikin wey doctors say get Cerebral Palsy. According to Sabi pipo, Cerebral palsy be one group of disorder wey dey affect pesin ability to move and maintain balance and posture. Di condition be di most common motor disability in pikin. Cerebral mean say e get something to do wit di brain. Palsy mean weakness or problem to use di muscles. Wetin dey cause Cerebral Palsy be abnormal brain development or injury to di brain wey dey develop wey affect pesin ability to control dia muscles. Di symptoms of CP dey different from pesin to pesin. Pesin wey get serious CP fit need to use special equipment to be able to walk, Or fit no dey able to waka at all and fit need lifelong care. Pesin wey get mild CP, fit dey able to waka small wit no balance, but fit no need any special help. CP no dey get worse ova time, though di exact symptoms fit change over pesin lifetime. All di pipo wey get CP get problem wit waka and posture. Many also get conditions wey relate like make dem no dey too sharp; seizure; problem wit vision, hearing, or speech; changes for di spine (like scoliosis); or joint problem (like contractures)." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61247288 +entertainment K-pop: How Korean culture [Kpop/Kdrama] don dey influence Nigerians "Korean culture [K-pop & K-drama] don dey influence Nigerians? Well, stay here make we yarn you wetin dey. For June 2020, Nigerians shock, as for one full day Lee Min Ho, one of Korea biggest Kdrama stars, Lee Min Ho trend for di whole world because say im dey celebrate birthday. As if dat one neva do im come release pictures of how im fans send am gifts sotay, e full one big room. How dem send am? For inside pandemic period oh! No try Korean stans. Oppa!!! Saranghe!!! Aigoo!!! Korean culture don enta di way some Nigerians dey tok ova di last decade since dem start to blow up for 2011. Weda na from Kpop or Kdrama be your plug to turn Koreanboo (one of di different names for fans of di Korean content), a number of young pipo don dey dey carry di mata for head, well-well. Even Kpop no cari last, Bangtan Sonyeondan (Bulletproof Boy Scouts) BTS wey dey dominate music all over di world. Even Wizkid lowkey tok say im go like to work with dem. Wizkid bin cover di one Kpop Idol, Se7en song for di beginning of im career. If you no believe am, enta social media yab di boy band, di way dia Army go come for you ehn, Beyoncé Behive no do pass dem. Kdramas for one, don set a lot of girls expectations enta roof. Like if you no fit kidnap me for your private plane to go weekend vacation for your private island, na dating be dat? But oda than dat na di emotions wey dey inside wetin dem dey do be di biggest flex. One fan, tok say ""I just feel the way wey dem di guys dey emotional for di series, dey very different from di men wey I dey see for Nigeria wey dey like to form macho."" And no be only dat one, Koreans don find ogbonge way through dia dramas to show dia culture, from historical drams (Jumong, The Moon That Embraces the Son), to tok about serious issues wey dey bother di kontri like classism (Pinocchio, Boys Over Flower), School bullying (School series) and even mental health (Kill Me Heal Me, Its Okay to Not be Okay, etc.) Howeva for Nigeria, many critics (haters) of Kdrama, think say e dey reduce IQ. Unlike most pipo think, e no really start for Nigerian with di very viral PSY Gangnam Style wey comot for 2012. E start from di manga inspired 2009 series ""Boys over Flowers"" wey be a love story between one poor girl and di richest teenage boy for di kontri, wey Lee Min Ho act. Yes di very same oppa. Di series comot for 2009 and e blow wella around di world and when e reach Nigeria around 2011. Why e blow? Well na because of fine boys, you know say I no go lie give you. We bin tok to a number of Nigerian fans of di series and dem confam say na because di boys fine well-well dem continue to watch Korean drama. One tok say, di men dey show dia emotions and na great difference from wetin she don see for Nigeria, howeva some similarities between di cultures dey. Many Korean fans for Nigeria dey tok about how similar, di cultures be. Dis generally dey boil down to one thing, respect. Korean language get different manner of speech from how you go tok to your friends, wey dem dey call Banmal to how you you fit tok with pipo wey senior you with honorifics. Also, dem dey hold dia food for chest very well. While some of dia food get inspiration from Japan and China, others get very deep meaning for dia history. For instance, Kimchi, wey be pickled cabbage for pepper, comot from di need for dem to get food to chop during dia harsh winter and till now certain communities still dey come togeda to make am every year. Last year e cause wahala with China wey dem say dia Pao cai, food wey dem dey ferment too better pass kimch. o don get palava on to Kimchi mata, So, even if Koreans travel go anywia, dem still dey rep dia Kimchi like Nigerians dey rep dia Jollof rice. For South Korea dem actually dey very intentional with di way dem dey promote dia culture to di rest of di world. From dia 1992 debut to di work wey dem dey put into dia production weda na Kpop or Kdrama, every piece of content wey don blow internationally dey planned, Even sef, dia Korean Culture and Information Service dey run ova 27 Cultural centres around the world wey dey promote Kpop and Kdrama, teach Korean Language, Culture, Taekwando and dey also give scholarships for foreigners to come learn from dem. So we follow some fans of Kdrama tok and dem say how Korean culture don influence dia lives. Jamila Thara: E don tear my eyes to embrace different types of culture and traditions and for di Korean Cultural Centre I don meet many beta pipo wey don become my family. Yemi: I be Yoruba girl wey bin no sabi speak her language and I bin no care, but as I dey learn Korean , I come discover say di culture, language and identity of pesin dey very important. No I dey aspire to learn more languages and to become polygot. Sharon Pwavi Babale: I be pesin wey always dey like interested in learning oda pipo culture and I come understand say if I tok to pesin with dia mother tongue, I dey speak to my heart. Being Korean stan also gove me job. Tife Sarang: I feel like say di Korean culture take style resemble Nigerian culture. However I don meet plenti pipo and learn more about Asian culture because of my Korean journey. Kemiola Dara: My Korean journey don expose me to oda cultures and show me oda world views wey don make me to be come more open minded. I don even use am start business wey I dey teach oda pipo how to speak di language." https://www.bbc.com/pidgin/world-55883883 +politics Ondo Election Update: Independent National Electoral Commission rules voters, candidates must follow on 10 October "Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) don announce rules voters must obey during 10 October Ondo State Governorship election INEC don draw ear give pipo wey wan comot to vote for election wey go happun on Saturday say dem no go allow pipo wey no wear face mask to join di queue to vote sake of Coronavirus Pandemic. Oda tins wey Ondo state INEC REC, Rufus Akejuof tok as wetin voters no fit do na: He tok say dem go arrest pipo wey do am immediately ""Vote buying no longer be joke"". He tok E tok say INEC no go allow voters to hold dia phone near di polling booth. Except for pipo wey don already get accreditation, INEC say dem no go allow pipo to join di queue fresh by dat time of di afternoon. Dem also encourage make pipo come in large numbers to vote." https://www.bbc.com/pidgin/media-54487139 +sports Milovan Rajevac: Ghana Football Association appoint Serbian as new Black Stars coach Ghana Football Association (GFA) don appoint Serbian, Milovan Rajevac as new head coach for de Black Stars. Dis be after dem task three member committee to find new coach for de National team after dem sack former coach, C.K Akonnor. GFA President Kurt Okraku, make de announcement today as he unveil de new head coach, two assistants den contract details to Ghanaians. Contract Details Per de arrangements, e go coach de Black stars for one year, if e qualify for World Cup den dis go extend to February 2023 after Arvin tournament happen. Coach Rajevac go earn $30,000 monthly salary. En job be to qualify Ghana to de World Cup den lift AFCON trophy. If e take Ghana to de World Cup e go earn $300,000 bonus. Milovan Rajevac, according to Ghana sports pundits be one of de most popular for Ghana sake of he lead Ghana to de 2010 World Cup. As head coach of de Black Stars e put together team wey perform well during de 2010 World Cup. As manager for Black Stars from August 2008, e continue de Black Stars qualification campaign to 2010 World Cup. Rajevac lead de team wey turn favourite during de tournament for South Africa until dem almost reach semi-finals. De Black Stars lose out to Uruguay during quarter-finals through penalty shootout. Milovan Rajevac quit Ghana after di World Cup on 8 September 2010. Rajevac be former footballer who play football professionally from 1973 to 1989. During en youthful days, e play for de Olympic team of Yugoslavia, Red Stars Belgrade New York Arrows. Milovan serve as Black Stars head coach for two years wey e handle 28 games. Two assistant coaches go assist Milovan Rajevac, one of whom be Ghanaian coach Maxwell Konadu. Second assistant coach be to support Otto Addo, who dey work for Germany https://www.bbc.com/pidgin/sport-58681606 +entertainment Timaya alleged 'hit-and-run' accuse: Wetin we sabi "Police for Lagos, south west Nigeria don confam say dem dey investigate Nigerian musician Inetimi Alfred Odon wey dey popularly known as Timaya for ""case of serious motor accident."" Di toktok pesin for di command Adekunle Ajisebutu tell BBC Pidgin say dem dey investigate di mata. Timaya bin chop accuse say e hit one woman for Ikate, inside Nigeria commercial capital Lagos on Wednesday One lady wey call hersef Osinubi Omowunmi, bin enta Instagram raise alarm of wetin happun and how di celeb take behave afta e allegedly hit her sister. @whyte_26, say: ""Dis celeb and how dem dey behave. Timaya nearly kill my dis morning. He hit her wit im car and run for Ikate few hours ago. ""He hit my sister and she come down to ask am to look at wetin im do. Di heartless human bin dey ask her for number and she tell am in go block her. Instead for @timayatimaya to do di needful, e hit my sister wit im car and runaway. One video for social media wey BBC no fit independently verify show as policemen dey pick up pesin wey resemble di singer from in house, enta car. Inside Instagram live wey Timaya do, im admit say true true im hit di lady car but im no even know say e hit am. ""Yesterday I bin just dey drive pass dis road, di fuel scarcity stuff make pipo block road, so I bin just dey try pass. And di next tin I hit d lady car and I no even sabi say I hit her. ""Wen she stop my vehicle I stop, she tell me say I hit her, I say how? Next tin she say I hit her for back. I say, I fit get your number, madam, I go call you, or I fit call you later, becos wey bin dey block di road. Di next tin I see four guys dey run down, so I bin dey try to move away. ""Na so di woman just hold di side mirror of my car. So na so she fall. No be like I hit her and run away, No."" E say im no even realise wetin happun to di woman, say na for social media im see am. Timaya name na Inetimi Alfred Odon dem born am August 5 for 1980, im come from Odi, Bayelsa state. Im na di last pikin out of fifteen children. Im papa bin be banker while im mama be trader. Im na Nigerian singer and songwriter and im solo careeer begin for 2005 wit di release of 'Dem Mama.' Im blow internationally wit im number three album 'Rebirth' wey im release in collabo wit Black Body Entertainment." https://www.bbc.com/pidgin/world-60608468 +politics Edo Election: Obaseki, Ize-Iyamu speak about dia relationship with Oshiomhole and politics for di state "Di candidates of di Peoples Democratic Party and Edo state Govnor Godwin Obaseki togeda with im rival for di All Progressives Congress, Pastor Ize-Iyamu don define dia relationship with Adams Oshiomole, di former national chairman of di APC. Inside exclusive interview with BBC Pidgin, di two main contenders for di 2020 Edo state govnorship election speak about di issue of godfatherism for Edo state politics and oda tins wey concern di election. Obaseki wey tok about wetin start di quarrel between im and Oshiomhole say e no take am as godfather but na Oshiomhole bin wan play godfather. ""I no see am as godfather, e help me, just as I help am, even before e become govnor, e tok am. Na me gada pipo, raise money, help am enta office as govnor. "" ""Dat relationship no be godfather, godson relationship"". Di govnor tok. Obaseki wey also speak about im decamping from APC to PDP say na drive dem drive am comot di party and di tin make am sad. ""Dem say I no qualify afta 4 years. I qualify di first time, dis time I no qualify. I come see say for APC, dem dey just dey do tins anyhow, di leadership go just come, dem no dey obey dia own constitution, court order, dem just dey do anyhow say na dem dey goment. Upon all dem say I no qualify make I comot, na im I leave dem and PDP wey see say I dey qualify give me oppourtunity to join dem"". E tok. Meanwhile, di APC govnorship candidate for di Edo election also chook mouth inside di issue of godfatherism for Edo politics and Oshiomhole. Ize-Iyamu say nobody except God fit be im godfather, e say im relationship with Oshiomhole na on friendship levels. ""How can Oshiomhole be my godfather? Im sef, if you ask am dat question e go say pastor, how I go be pastor godfather. Wen Oshiomhole wan contest for govnorship election e hear say I wan contest e had to come and meet me say abeg oh, e wan contest and I agree because I tell am say wia you come from Edo North dem never get govnor before. I support am dat time."" Ize-Iyamu tok. On di reason im decamp from PDP to APC, Ize-Iyamu say im see di party as more progressive. ""Even wen I dey dat side, na my simple agenda, I come now, na my simple agenda, in terms of ideology, in terms of agenda I dey consistent, di problem na di vehicle. Now I see APC as a more serious and viable vehicle. I also see APC as more progressive minded dan APC. I don get di opportunity to dey both of dem so I know di difference"". Ize-Iyamu tok. ""I no hide am say di reason I dey politics na to assess goment for di benefit of my pipo... so wat is selfish about dat? My agenda dey very clear, e dey selfless. If na to say make pesin dey enjoy, God don bless me, I dont need to be a govnor, to be able to enjoy myself but I keep telling pipo, if you are rich and everybody around you are poor, you are poor"". Ize-Iyamu add." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53780249 +business Ecowas meeting for Niger elect Nana Akufo-Addo, President of Ghana as new Ecowas Chairman - See five challenge dem im go face "Economic Community of West African States (Ecowas) don elect President Nana Akufo-Addo as di new Ecowas Chairman. West Africa regional join-bodi elect Prez Akufo-Addo as di new Chairman on Monday for di ongoing 57th Ecowas Summit wey dey happun for Niamey, capital of Niger. Di Ghanaian leader dey take over from President of Niger, Mahamadou Issoufou wey be di current chairman of Authority of Ecowas Heads of State and Government. Dis issues wey dem dey discuss na some of di challenges wey di Ghanaian leader go face as Ecowas Chairmo include: Nigerian President Muhammadu Buhari don call on West African leaders to obey di number of years dem suppose stay in power alias dia constitutional term limits. Dis tok dey follow Ivory Coast President Alassane Ouattara decision to run for a third term for di October general elections. President Buhari comments drop during di comment during summit of leaders of di Economic Community of West African States inside Niamey, the capital of Niger. President Ouattara decision to run for a third term following di sudden death of di pesin wey suppose succeed am and di move triggered protests for Ivory Coast. Im critics say di move no follow wetin constitution tok. Di one day summit wey open on Monday, na eight heads of state, including presidents of Ghana, Senegal and Burkina Faso attend am. Oda mata wey dem discuss for di meeting include di ongoing security crisis in Mali. Di Ecowas leaders call for sharp-sharp transfer of power to civilian rule afta one military coup on 18 August. Di regional join-bodi of West African leaders don already place punishment ontop Mali and ask for elections to take place within a year. Many West African leaders post goodwill message for di Ghana leader ontop im new appointment as new Chairman of Ecowas. Belle first sweet im wife Rebecca Akufo-Addo Ivory Coast leader also hail di new Ecowas chairmo President Macky Sall of Senegal also wish President Akufo-Addo success for im new role The Gambia leader follow throway salute Di Niger President wey hand over to President Akufo-Addo, also hail im successor ""I beg my colleague Heads of State to give ginger support to Ecowas decisions, and build fast and quickly our Community. Our pipo deserve more, and di objectives of peace, progress and prosperity go therefore be within our reach, make we for realising di historic purposes of Ecowas."" Na wetin di Ghana Prez. Akufo-Addo tok on Monday afta e take over as di Ecowas Chairman. Wen we think of West Africa togeda wih our individual kontris, we no go just become united pipo inside Africa alias pan-Africanists, we go also become true pipo wey believe in our kontri alias nationalists, because wetin make West Africa more prosperous go make each of our individual kontris more prosperous, Akufo-Addo add." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54059748 +politics Dino Melaye: 'Why I wan become di govnor of Kogi state' "Senator Dino Melaye don buy govnorship form to contest di November govnorship elections for Kogi state, north central Nigeria. for di Peoples Democratic Party. Di Peoples's Democratic Party lawmaker wey make di announcement inside press conference on Thursday for di PDP headquarters say e go ""restore di long lost reputation of di state."" Oga Melaye say, ""I dey very excited and happy say we don start di journey to recover we state from economic scavengers and financial cankerworms."" ""People dey die for Kogi State, crime dey di highest level for di history of di state, unemployment dey everywia and non payment of salary don turn di tradition"", na wetin e follow tok. E also tok say na Kogi state pipo want am to run for di election. E call for peace and calm during di process wey go lead to di election. According to Dino, im main aim na to revive di economic state of Kogi, and education for di state." https://www.bbc.com/pidgin/tori-48851627 +entertainment Billie Eilish pause show for London ontop fan safety "Billie Eilish bin briefly pause her show for London's O2 arena on Saturday afta many fans get into difficulties sake of hot temperatures. ""Una dey ok?"" she ask. ""Pipo bin dey faint and dem dey pull dem out. E dey hot, I know"". Afta fans say dem dey ""squeeze"", she stop di music until di pressure for front of di stage reduce. ""Take a step back, give everybody some space,"" Eilish tok. ""If anybody look like dem wan faint, just tell someone."" She add am: ""No try to save feelings."" Earlier, Eilish bin ask di O2 security team to share water to di audience. Dis no be di first time wey di singer don stop a concert to check on her fans. For February, she bin interrupt one Happier Than Ever tour show for Atlanta afta she notice pesin dey struggle to breathe, and she no gree continue di show until dem get inhaler. ""We fit just grab one?"" she ask one crew member. Later dat month, she also pause one show for Madison Square Garden inside New York, dey tell fans: ""If you wan sit down, you dey allowed. Go ahead, you're good. Sit down, take a breath."" Di issue of crowd safety don become spotlight since 10 pipo die during one crush for Travis Scott Astroworld festival for Houston last year. Fans for di audience later criticise di response of emergency services, and ask why organisers no stop di concert. Investigation still dey go on to sabi di circumstances wey lead to di tragedy. For di O2 on Saturday night, fans take matters into dia own hands. One group, afta dem notice one fellow concertgoer in trouble, dem form protective circle and turn on dia phone lights to alert di security team. Eilish resume her show afta three minutes. She later thank ""all di security [and] all di staff"" for di venue, add am say: ""I appreciate you""." https://www.bbc.com/pidgin/articles/crgw5yj0wzxo +politics Lagos Ex-Governors Pension: Sanwo-Olu wan stop Tinubu, Fashola, Ambode three cars, house for Lagos and Abuja wey dey inside pension for ex-govnors Three cars, house for Lagos and Abuja dey part of wetin former governors for Lagos bin dey collect as pension but the state goment don tok say dem wan stop dat package. Di state govnor, Babajide Sanwo-Olu, submit one bill for di stte house of assembly say im wan remove di law wey make am complusory for di stte to pay im ex-govnors pension. According to tweet wey Jubril Gawat, wey be special assistance to di govnor on new media, tok say di govor wan repeal di Payment of Pension Law 2007. Lagos state don get three govnors since Nigeria go back to democracy after military rule. Bola Tinubu, wey be di national leader of Nigeria ruling party, All Progressives Congress (APC) now, na im be di first govnor from 1999. Babatunde Raji Fashola wey be di current Minister of works and housing for Nigeria, be di second govnor and im serve for 8 years. And di third govnor na Akinwunmi Ambode, im serve only one term and fail ge im party ticket for second term. https://www.bbc.com/pidgin/media-54914100 +sports Tearful Federer wave bye-bye afta final match to retire from tennis "Cry-cry Roger Federer wave byebye to professional tennis afa e team up wit fellow great Rafael Nadal for one emotional nightfor di Laver Cup. Di 41-year-old receive one long ovation afta e walk comot court for di final time as e retire as professional. Di Swiss, wey bin win 20 Grand Slam singles titles, dey considered as one of di best players for tennis history. ""E be wonderful day. I dey happy, I no sad. E feels great to dey here. I dey happy I make am through,"" e tok. Federer cry as e hug Nadal and oda players, den gbab praise from di thousands of fans wey dey shout im name for di O2 Arena for London. Nadal also no fit hold back di tears. Di 36-year-old Spaniard bin cry as e siddon alongside Federer as dem dy listen to British singer Ellie Goulding, wey round off one memorable night wit one performance. Federer and Nadal - for long rival for di top of di men game - bin join forces to play doubles against American pair Jack Sock and Frances Tiafoe for di annual team event between Europe and di rest of di world. Despite say Federer no play competitively for over one year, di two veteran bin push Sock and Tiafoe bifo losing 4-6 7-6 (7-2) 11-9 as Team World level for 2-2 for di end of play for di opening day. Federer and Nadal - wey dem affectionately nickname 'Fedal' - almost win am. Di pair don match point for 9-8 for di decider, but Federer fit only lunge for one forehand wey e push into di net. Di defeat bring di former world number one 25-year professional career to close afta im 1,750th competitive match across singles and doubles. ""E be di perfect journey. I go do am all again,""Federer tok as e try to hold back tears during im on-court speech. Federer career bin long dey on di downward slope, e bin dey battle one knee injury for di past two years and need three operations for bid to overcome di wahala. E bin no play competitive match since e lose to Poland Hubert Hurkacz for di quarter-finals for Wimbledon last year. Despite say e dey restricted to only three of di 11 Grand Slams wey dem stage since di start of 2020, e hope as recently as July e go still dey able to return to di major tournaments. But, afta scan bring further bad news, Federer announce last week say e go retire sake of im ""body message lately don dey clear"". Federer don tok about say e go throw party to mark im final match, say e want di occasion to dey fun and not funereal. As e wish,e bin get celebratory atmosphere for di 17,500-capacity arena. Di key numbers for Federer career 20 Grand Slam singles titles 310 weeks as world number one\n103 ATP titles 28 Masters 1,000 titles\n6 ATP Finals victories 31 Grand Slam finals\n1 Davis Cup triumph £114m career prize money Im wife Mirka, dia four children, plus im parents Robert and Lynette watch di match, Federer every move dey greeted wit cheers wey contain one mixture of euphoria and empathy. Di family join m on court afta during one touching celebration, wey see many more tears and Federer lift up by im fellow players. ""Everyone here, di boys and girls. My wife bin dey so supportive. She for don stop me long, long time ago but she no do am,"" Federer tok. ""She keep me going and allow me to play, so e dey amazing - thank you.""\nDi presence of some tennis legends including Rod Laver, along wit celebrities including Hollywood actor Hugh Grant and Vogue editor Anna Wintour, add to di occasion. Current world number ones, Carlos Alcaraz and Iga Swiatek, bin tweet dia range of emotions as dem watch di match for television, as Federer Swiss Davis Cup team-mate Stan Wawrinka sef do. Federer bin only fit enough to play doubles sake of one knee injury and im movement dey limited.\nAfta, e bin joke say dey happy to get through di match as e no pull one muscle for im calf or back. ""To dey wit di guys and have family and friends, I no feel di stress so much even if I feel say sometin go go during di match,"" Federer tok\n""I dey so glad I make am through and di match dey great. I no fit dey happier."" No be only say Federer push boundaries wit im play and set surplus records, e also become one of di most popular players tennis don ever see. Im style of play - wey dem describe as balletic, graceful and fluent -don make millions of fans across di world to like am. So too be im polite and charming personality. Federer transcend tennis. For some, e almost transcend di world.\nBifo di match, you fit see hundreds of fans filing into di arena wear Federer-branded clothing and accessories. Hats, T-shirts, scarves, banners and even custom-made earrings. All red and white - di national colours of Switzerland - wit most decorate wit di initials of dia hero: RF. Few Swiss flags also dey draped around di indoor arena.\nOne Federer super-fan for di O2 Arena, Robert Springer from Poland, describe im idol as di 'King of Tennis"". ""E get quality, empathy, one super sportsman, one gentleman and one good father. Plus e always get time for im fans. E be di one and only,"" Robert tell BBC Sport. Tickets for di night session on Friday dey already sold out before Federer announce last week e go retire afta di annual team event. Initially dem dey available from between £40 and £510. Following di news, dem bin offer on resale platforms for over £1,000 each. Despite di match finishing at 00:26 BST, as di celebrations continue for about anoda half an hour, few of those wey present commot di end. ""Thank you everybody. I get so many pipo wey cheer me on and you guys here tonight mean di world,"" Federer tok, wey later add say e dey""really scared"" about speaking on court sake of e know say e go get emotional. ""Dis no be di end-end, you know, life goes on. I dey healthy, I dey happy, everything great, and dis be just one moment in time.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2xd2kgry65o +sports Champions league predictions: Real Madrid vs Inter Milan, AC Milan vs Liverpool, oda games "Uefa Champions League match day six go see teams play di last match of di group stage One of di main matches wey go shele go be Liverpool vs Ac Milan. Liverpool don win dis tournament six times and some football fans don dey reason say dem fit lift di trophy again for 2021/22. Wit di form of Mo Salah, dem fit get chance to win games no matter di opposition. AC Milan sef no carry last as dem sef get better history for di competition. But tins don change small for dem in recent years plus sake of 40-year-old Zlatan Ibrahimovic be one of dia best players na anoda tin. Dem fit take second spot and move to di knockout round wit one win here sha. Real Madrid vs Inter Milan too na one ogbonge match wey pipo dey look out on Tuesday. BBC Pidgin follow Damilola Onifade wey be sports analyst tok to reason wetin fit play out for two out of di games wey dey today. AC Milan vs Liverpool and Real Madrid against Inter Milan go make football fans to tanda for dia TV for di 90 minutes plus wey both matches go last. Dis na according to Damilola Onifade dis two matches, E say AC Milan get everything to play for and possibly everything to lose if dem fail to win dis evening. Dem currently siddon for di third in di group behind group winners Liverpool and Porto, on four points. Even if dem win, e fit no see dem through to di knock-out stage particularly if FC Porto win for di oda group game against Athletico Madrid. Di first game against both sides dey right wit Liverpool edging 3-2 for Anfield stadium. E mean say dey don lost dia last three meetings against di Reds including one 2-0 home defeat for 2014.Liverpool get tricky Premier League tie coming up on Saturday against Aston Villa. Dat one fit make Jurgen Klopp to rest some of im best players for dis game.""Dis game get one draw wey dey written all over am and I think dat go be di outcome tonight"". Real Madrid Inter Milan be interesting fixture. Di two clubs don qualify but go prefer to top di group and givedemsefs di possibility of one ""weaker"" opponent for di first knockout round next year.Both teams dey on good run to win dia last five matches for all competitions. Wit 12 points and two ahead of Inter, Real only need one draw to top di group. While Inter must win.Real don win dia last four meeting including di first leg for San Siro. Di last time Inter win against Real though na for 2014 for di Bernabeu. Maybe dey fit draw inspiration from dat night.""I think Real go do enough to get at least one draw"" e add. Liverpool oga Jurgen Klopp say e go rotate im side for dia final Champions League group game for AC Milan. Dis one na sake of fear of punishment from im medical team if im no do am. Today game go be di third out of nine wey di Reds go play for December. Klopp side don already seal top spot for Group B as dem bin don claim five ogbonge wins from five so far. ""We have to rotate, we go rotate,"" Klopp tok. ""Di medical department go smash me if i play di same side again, so I go make changes."" As Liverpool dey assured of top spot, all three oda teams wey dey Group B dey run to claim di runners-up spot. Porto dey currently occupy di position on five points, one more dan both Milan and Atletico Madrid. One win for di Portuguese side at home to Atletico go seal am. Meanwhile, if both Atletico and Milan win, e go come down to goal difference as dem go tie for dia head-to-head record. Di Italian side dey currently one goal better off dan Diego Simeone team. Milan bin dey struggle wit injuries , Pietro Pellegri wey dey pick up on groin problem go join Samu Castillejo, Olivier Giroud and Ante Rebic for di sidelines. Zlatan Ibrahimovic, wey get six goals for 12 matches dis season,dey likely to lead di line. Di Italian side come into di game afta back-to-back wins, over Genoa and Salernitana, wey leave dem top of Italy top-flight." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59550671 +sports Villareal 0 - 2 Manchester United FT: Ronaldo, Sancho goals see Man United to Champions League last 16 "UEFA Champions League return on Tuesday evening and football fans already dey happy to see how di different group matches go shelle. Some teams don already qualify while some dey hope say dem go pick maximum points from Tuesday matches. Di match between Villareal and Manchester United shele for di Estadio de la Ceramica and e kick-off around 6:45pm Nigerian time. Na Villarreal 0 - 0 Manchester United afta first half. Cristiano Ronaldo goal for 78 minute and Jadon Sancho 90 minute goal make Manchester United reach di last-16 of di champion league. Afta Ole Gunnar Solskajaer sack last Sunday, plenti pipo eyes go dey for dis match ontop say dem wan see as caretaker coach Michael Carrick go coach. As e be so Manchester United get plenti injuries to worry about, Paul Pogba get injury for him thig. Raphael Varane get hamstring injury, Luke Shaw too get anoda injury wen Manchester United play Watford last weekend Mason Greenwood get Covid-19 and anoda stiker Edinson Cavani wey wound for him tendon fit no play too. Di interim coach Michael Carrick, don win Champions League wit Manchester United aft a im spend 12 years for Old Trafford wia him bin dey play football. Now, Carrick get evritin to fight for, sake of say e no go good say him start wit defeat. E dey very important for Manchester United to win dis match sake of say dia last three matches no go well as dem loss all di three. Since Manchester United beat Villareal for Old Trafford on 29 September afta Cristiano Ronaldo's score di winning Goal for di 95th minute, di Red Devils manage to win two of dia matches out of eight. If dem win today match e go give dem beta hope to qualify for di next round Villareal and Manchester United get seven points United and Villarreal get seven points, Atalanta sitdown for 3rd position wit five points for inside Group F. If di top two teams dey tied on points, points in head-to-head matches between di tied teams na im dem go use to determine who finishes top. United go qualify if dem win Villareal on Tuesday or if dem manage play draw wit di Spanish team. Michael Carrick tok say di match ""na big one for di two football clubs "" and im dey ginger all Manchester United players to do dia best. ""Wetin dey important now na to get di right results and how we take do our work,"" di five-time United Premier League winner tok ""Villarreal na very good team. Dem dey organised and get beta coach. Villarreal, wey be di number 12th team for di Spanish La Liga, dn draw 2 of dia last match dem for di Champions League home games wit Manchester United. Dis na Villarreal sixth Champions League match against Manchester United. Di Yellow Submarine neva win all dia last five matches wit di Red Devils. Manchester United don fail to keep clean sheet for di Champions League dis season. Na seven goals dem don chop for four matches. Villarreal neva win any English club for di Champions League inside 11 attempts . Na only seven of dia last 24 away Champions League matches Manchester United don win. Chelsea need only one point from dis next two matches to qualify for next round wey be di round of 16. We no dey sure weda Germany forward Kai Havertz go play becos e get hamstring problem afta dia match against Leicester city. Anoda Germany striker Timo Werner, get hamstring injury since October fit play, Jorginho dey fit. Former Arsenal midfielder Aaron Ramsey, Italy defender Giorgio Chiellini and striker Federico Bernardeschi dem go play for Juventus while top scorer Paulo Dybala fit no play. Juventus tanda for 8th position for Serie A with six wins from 13 matches dis season. Fisayo Dairo wey be sports writer predict say Manchester United go win Villareal 2-1 and Chelsea go win Juventus 2-1. Anoda sports broadcaster Bade Adeleye predict say Manchester United go win Villareal 3-1 and Chelsea go beat Juventus 2-1. Wale Ayeni tok say Villareal and Manchester United go play 2-2 draw while Chelsea go beat Juventus 3-2." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59393207 +health Coronavirus update: Ghana make ready to fight Covid-19 outbreak? "Ghana dey intensify efforts to prevent against coronavirus from entering de country. Despite preparations by government, some Ghanaians say dem no believe say de country make ready to fight di disease. Health Ministry for Ghana set up 100-bed capacity facility inside one remote area to quarantine suspected cases. Dem also secure some 5000 personal protective equipment for health personnel which dem share across various regions. Dem go take quarantine people wey display symptoms of coronavirus. Despite these efforts some feel say e preparation no be enough. One Ghanaian, Benjamin talk BBC Pidgin say ""if you check de quarantine measures, Ghana no make ready to fight coronavirus. We for learn from Rwanda where dema goment put washing basins inside de city, Kigali make people wash dema hands."" Another lady, Magdalene Mensah wey BBC Pidgin talk to explain say ""even normal hospital cases people no dey get beds sleep top, hospitals already dey under pressure. I doubt say we make ready to deal with coronavirus."" President Akufo-Addo place temporary travel ban on public officials so say dem no go catch de virus during travels. So far Ghana health service budget initial Ghc35 million, plus additional Ghc11 million to fight de virus. Some Ghanaians dey call on goment make dem close de entry points make people no enter de country. So far kontries wey dey share border plus Ghana like Togo den Burkina Faso all get de virus some." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51792133 +sports Caf Awards 2019: Sadio Mane, Asisat Oshoala win African Player of the Year Sadio Mane and Asisat Oshoala na dem be African Player of di Year for men and women. Senegal and Liverpool forward Mane beat both Egypt player Mohammed Salah and Algeria winger Riyad Mahrez to win di award wey dem do for Egypt on Tuesday. Na di first time CAF go name Mane as di African Footballer of the Year afta e come out third for di two editions. For di women category, Asisat Oshoala beat Ajara Nchout from Cameroon and Thembi Kgatlana from South Africa to win her fourth African Women's Player of the Year. Mohamed Salah (Egypt & Liverpool) Riyad Mahrez (Algeria & Manchester City) Sadio Mane (Senegal & Liverpool) - Winner Ajara Nchout (Cameroon & Valerenga) Asisat Oshoala (Nigeria & Barcelona) - Winner Thembi Kgatlana (South Africa & Beijing Phoenix FC) Anice Badri (Tunisia & Esperance) Tarek Hamed (Egypt & Zamalek) Youcef Belaïli (Algeria & Esperance / Ahli Jeddah) - Winner Achraf Hakimi (Morocco & Borussia Dortmund) - Winner Samuel Chukwueze (Nigeria & Villarreal) Victor Osimhen (Nigeria & Lille) Aliou Cisse (Senegal - Senegal) Djamel Belmadi (Algeria - Algeria) - Winner Moïne Chaâbani (Tunisia - Esperance) Alain Djeumfa (Cameroon) Desiree Ellis (South Africa) - Winner Thomas Dennerby (Nigeria) Algeria - Winner Madagascar Senegal Cameroon - Winner Nigeria South Africa Riyad Mahrez goal against Nigeria for Afcon 2019 semi final Kodjovi Obilale Egypt Football Federation Mois Katumbi - President of TP Mazembe https://www.bbc.com/pidgin/tori-51023254 +entertainment Chief Emeka Morocco Maduka: Death of Morocco Maduka wey be top Nigerian highlife musician Chief Emeka Morocco Maduka, wey be top Nigerian highlife musician don die. Morocco Maduka die on Thursday 29 October, 2020 one of im close padi confam to BBC.. Chukwudi Avoaja wey be member of di joinbodi of musicians for southeast Nigeria PMAN, wey also play music wit am [Morocco Maduka] say dem bin dey plan to do birthday party for am on Sunday before di news of im death land. Morocco Maduka na popular musician wey im music dey touch for body. For interview wey im bin do wit BBC, Morocco Maduka tok say im be electrician before im enta into music. https://www.bbc.com/pidgin/world-54744261 +politics Ghana elections 2020: Voters List, EC accreditation for election 2020 in Ghana - How to cast your vote on election day Electoral Commission of Ghana [EC] don announce how di voting process go dey like during di kontri presidential election on Monday, December 7, 2020. Ghana election commission say list di 9 easy step wey electorate must follow to vote for dia choice candidates: Electoral Commission of Ghana (EC) put out 12 presidential candidates who voters go choose from. Since de inception of de Fourth Republic, Ghana dey practice voting system, First Past the Post or Simple Majority. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55113902 +entertainment K-pop star Jin from BTS begin im military service "Jin, wey be di oldest member of K-pop mega-band BTS, don enter military service - di first of di group wey go do so. Di 30-year-old bin post foto of imself wit im new military haircut before enlisting on Tuesday. ""E look cuter dan I expect,"" e tok. As South Korea still dey technically for war wit im hostile neighbour North Korea, all able-bodied men dey required to serve for di army. Jin don begin five weeks' training for one bootcamp near di North Korean border. Afta dis, e go dey reportedly assigned to one frontline unit. Dis news send im millions of adoring fans into frenzy. For di Yeoncheon bootcamp, wia Jin don enrol, recruits sleep on top mats for floor, im rooms wit 30 pipo. Dem dey teach dem how to handle weapons and fire live ammunition before dem go put dem through demanding wartime scenarios. Cadets bin tell us say di most challenging tasks dem dey face be make dem dey sealed for gas chamber, to experience di effects of CS gas, and make dem detonate live grenade. ""I bin dey pretty nervous to hold di grenade and shock to learn how powerful e be,"" 22-year-old Yang Su-yeon, wey complete im training for Yeoncheon last year tok. ""E be physically demanding, but mentally e dey okay. All di drill sergeants dey friendly,"" Yang tok. Afta training, Jin go reportedly dey stationed near di North Korean border, wit one frontline unit. North and South Korea dey separated by one 4km (2.5-mile) wide strip of land, wey run along di length of dia border, wey dem sabi as Demilitarized Zone (DMZ). Both sides dey fenced off wit barbed wire and dey heavily armed. Yang bin spend im service as one out-post guard for di DMZ, wit di 5th Infantry Division, wey be one of di most frontline positions. E go keep watch through di night, and constantly dey survey di North Korean soldiers for di other side, e go use thermal imaging equipment. ""Sometimes I dey see di North Korean soldiers dey chop beating, either kicked or slapped for face,"" e tok. ""Dey ghatz do manual labour sake of dem no get nice equipment like us to help dem."" Yang say to watch di North Korean soldiers make am feel grateful for im own experience. ""When I see wetin dem ghtaz do, I realise, 'Wow, I dey so much more comfortable.' I dey feel sorry for dem."" But BTS Jin go need witstand di cold winter wey dey come . Yang remember days wey e spend dey shovel snow as temperatures fall below -20C. ""When we go outside, our eyelashes go freeze,"" e tok. Yang praise di culture of im unit: ""Sake of say we carry guns wey dey loaded wit ammunition, we ghatz remain calm, so no harassment or beatings go dey."" Yang bin volunteer to dey deployed as frontline guard, as dis position dey come wit perks, including more time off base. E dey more likely say Jin go dey sent to one base set further back from di DMZ, like 26-year-old Heo Sungyoung, wey spend im service wit di 6th Corps Command Centre from 2018 to 2020. For di first six months e bin guard di entrance to di command centre. ""E dey so long and boring. I get nothing to do but dey look di sky,"" Heo tok. From there, e dey moved to di logistics team, where e dey responsible for ordering of supplies like tissues and socks. South Korea compulsory military service be di source of grievance for many young men, wey no happy say e take dem away from dia studies, work and friends. For months e dey rumoured say di goment fit allow di members of BTS to skip di service, on di basis say dey already serve dia kontri by earning am billions of dollars, and e go dey more beneficial to allow dem to carry on doing so. But for October, di members of BTS bin announcesay dem all dey plan to enlist, wit Jin, wey be di oldest, to go first. Even so,di reports say e go dey sent to di front line surprise some fans, wey don assume say dem go give am less risky role. E bin get one special unit for celebrities, where dey fit continue to work as entertainers and dey given privileges. But one public outcry happun when dem find say some of dem dey abuse di system, by leaving dia barracks more often dan e dey allowed. For 2013, di two-tier system bin dey scrapped. ""If I say e no feel like waste of time, I go dey lie,"" Yang wey dey stationed for di guard post tok. ""If I get di choice again, I no go do am. I for don  learn so much more inside 18 months for di real world. ""My advice to Jin be to just wait im time and pray say e pass quickly."" But Heo, from di logistics team, get better memories. Initially e bin say e questioned, like many men for dia 20s, why im suppose dey there, but e end up to learn some valuable lessons. ""For school, I bin don only mix wih pipo from di same background, but inside di army, everyone dey so different. I realise how much bigger and more diverse di world be."" Im advice for Jin be to enjoy dis experience. ""As one top star, e for no get much opportunity to meet normal pipo. Dis go be good for am, I think."" Online, tens of thousands of fans don already message Jin to offer dia own advice and tell am how terribly dey go miss am. ""Please take care and bring enough warm clothes and medicine,"" Maliah Leah write. ""I hope your colleagues treat you well. We go dey wait patiently for your comeback.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cq5e10rzlvgo +sports Undertaker retirement: WWE star The Undertaker don 'retire' from wrestling "After almost 33 years of wrestling, Di Undertaker don hint say e career don dey ova, according to one WWE documentary wey dem release on Sunday. During di final episode of im Last Ride docuseries, Di Undertaker say im dey at peace say im no dey wrestle again. Dis na sometin wey im no fit do even as im don tease say im wan retire for some time now throughout di years. Undertaker wey e real name na Mark Calaway tok say ""I dey at a point wey be say dis time di cowboy really need ride away."" Afta im tok say e get nothing more to accomplish, e be like say Undertaker don dey okay wit wetin im don do and to spend e future for house. ""I believe say I dey at a place now, afta-Boneyard, wey be ogbonge battle against one of di best for di business. Here you dey, dey climb on your motorcycle and you dey take off. E get a lot of thought and a lot of emotion, one of dem na 'you dey happy enough with dat?' Na one powerful moment. You no dey always get those kain moment."" Di World Wrestling Entertainment put out tweet to say ""#ThankyouTaker #TheLastRide"" but dem no formally announce e retirement. Pipo ontop Twitter sef join to respond to Undertaker 'retirement' with emotions. See some of di best response." https://www.bbc.com/pidgin/sport-53138995 +sports Lionel Messi Barcelona FC team training fotos Lionel Messi come out to do training wit FC Barcelona for di first time afta e fail to leave di club. Di Barcelona captain train wit di team on Thursday unlike Monday training wen di World Player of di Year train alone before getting di results of one corona test. Messi bin train wit a number of Barcelona players, including Philippe Coutinho, Sergio Busquets, Frenkie de Jong and Ansu Fati. Messi go tanda for anoda season wit FC Barcelona, ​​afta e no fit leave leaving di club, as e be say any pesin wey wan buy am must cough out 700 million euros before dem let am go. Dis na how Messi train wit FC Barcelona team members https://www.bbc.com/pidgin/sport-54104133 +politics Muhammadu Buhari speak on Nigerian protest against SARS [#EndSARS] afta Ughelli killing "President Muhammadu Buhari giving marching order on Friday night afta e meet Inspector General of Police (IGP) ontop #EndSARS Buhari meet IGP ontop #EndSARS protest across Nigeria. ""Our determination to reform di police make e no dey in doubt. I dey briefed regularly on di reform efforts ongoing to end police brutality and unethical conduct, and ensure say Police are fully accountable to di pipo."" Buhari tok. Di Nigerian leader meeting wit di police chief dey come afta two whole days of protest wey staet for Lagos and spread across di kontri since Wednesday dis week. #EndSARS become di number one Twitter trends on Friday around di world sake of wetin dey happun for Nigeria. For Nigeria, some social media users dey even post #BuhariResign sake of di #EndSARS protest across Nigeria. Di president say di IGP already get my strong alias firm instructions to finally address di concerns of Nigerians regarding di plenti anyhow behaviour alias excesses of SARS officers and ensure say officers wey commit face justice. President Buhari for message e post ontop im official social media page beg for for patience & calm, even as Nigerians freely exercise dia right to peacefully make dia views dey known. Di plenti majority of men and women of di Nigeria Police Force believe in Nigeria alais dey patriotic and committed to protecting di lives, property and area of Nigerians, and we go continue to support dem to do dia job, President Buhari add. Nigeria inspector general of police bin don ban di unit from doing stop and search duties and setting up roadblocks on Sunday 4 October as tempers boil sake of everiday harassment and police brutality wey many claim say na SARS officers dey commit. IGP Mohammed Adamu also tok say members of the Special Anti Robbery Squad (Sars) must always wear uniforms but Nigerians want Sars to end completely so dem enta road do protests across di kontri. Details later. As Nigerian youths enta road dey shout end sars, President Muhammadu Buhari receive briefing from National Security Adviser Maj. Gen. Babagana Monguno (Rtd), wey Coordinator Presidential Amnesty Programme Col. Milland Dixon Dikio (Rtd) escort to State House, Abuja on Friday. For years, videos wey appear show SARS officers extorting and assaulting civilians don spread for social media. Last weekend Nigeria inspector general of police bin don ban di unit from doing stop and search duties and setting up roadblocks Tori be say Nigerian youths and celebrities dey demand goment to completely ban police unit- Special Anti Robbery Squad wey dem accuse of many brutality." https://www.bbc.com/pidgin/54487651 +politics EndSARS Protests: IGP order riot police deployment across Nigeria afta curfew in Lagos Police Inspector General Muhammed Adamu don order riot police unit to immediately enta streets sake of violence for di #EndSARS protests. Dis order wey land Tuesday afternoon mean say anti-riot police unit and di Police Mobile Force (PMF) alias MOPOL don get collect marching order to enta road and keep di peace across di west African kontri. Oga Adamu make dis announcement following how di #Endsars peaceful protest wey begin for early October across Nigeria but begin turn violent since dis week. For Kano, violence burst for di EndSARS protest inside di northern Nigerian city. For Lagos State 24 hour curfew for all parts of di state starting take effect from 4pm today. And na only essential workers and front ine responders go fit dey road afta di curfew. Di Inspector General of Police no stop dia, e also order for massive deployment of police officers dem to prisons dem and make sure say security tight around all di prisons alias correctional facilities plus secure all oda critical national infrastructure for di kontri. On Monday, jaguda pipo wey claim to be EndSARS protesters cause prison break for Benin and Okoh prisons inside Edo State and burn down two police stations and one police police post. Di mata make Govnor Godwin Obaseki order 24 hour curfew from 4pm Monday 19 October. Di senate now don ask President Muhammadu Buhari to address Nigerians on di #EndSARS protests urgently. Still on di same day, thugs attack and burn cars for Abuja leading to ethnic attack wey don turn bloody. For jos, north central Nigeria, di story no different as attacks di happun for dia and di final bus stop na for Lagos state wey dem burn one police station. Amnesty International say fifteen pipo dem don die on top di ongoing endsars protest and na sake of dis di IG command di anti-riot unit to enta street and ensure say dem protect di lives and property of pipo. IGP Adamu further yarn give for statement say make di commissioner of police for all di 36 states must find and gbab alias fish out all those wey get hand for all di attacks and arrest dem And afta dat, make sure say dem face di law of di land and pay for dia crime. https://www.bbc.com/pidgin/world-54621398 +health Kenya Covid-19 UK travel ban, other African countries on England travel ban list - See wetin to know "Travel from di Philippines, Pakistan, Kenya and Bangladesh go dey banned from next week, UK government don announce. Di kontris dey join England ""red list"" sake of concerns about di spread of new Covid-19 variants. From 04:00 on 9 April, international visitors wey dey travel from or through dis kontris in di previous 10 days no go fit enta England. But exception dey for British or Irish passport holders, or pio wey get UK residence rights. But dem must first pay quarantine for one goment approved hotel for 10 days. During dia stay, passengers go take two coronavirus tests - but a negative test result no mean say dem go reduce dia time in quarantine. Dem no go fit end dia quarantine early through di Test to Release scheme, but travellers from non-red list kontris fit leave home isolation afta dem test negative on day five. Di Department for Transport (DfT) say information about exemptions for nurses wey dey come from di Philippines ""wey dey critical to supporting di NHS during Covid and di recovery"" go fit comot before Friday. Di reason for travel bans na to reduce di risk from new coronavirus variants like di South Africa strain, di Department for Transport (DfT) say. Dis na based on advice from di Joint Biosecurity Centre. Data don show say most cases of di South Africa coronavirus variant wey dem see for UK so far don dey linked to international travel, and plenti of dem no dey come from Europe, di DfT tok. No direct flight bans from di four new kontris go dey in place, but dem don advise passengers to check dia travel plans before departing for England. Simon Calder, wey be travel editor for Di Independent, say government get ""plenty of evidence say risk from new variants of concern dey come in from these countries"" and di numbers dey shocking. But he say di changes fit cause a ""great deal of problems"" for many wey dey UK and dia family wey dey live for di four affected kontris as dem get less dan one week to get home if dem dey oversea. He say ""bookings don increase"" ahead of next Friday. Under di current rules, foreign travel from di UK dey banned Di earliest date pipo from England go fit travel abroad for a holiday na 17 May wen di government move to step three of dia lockdown exit plan." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56617082 +sports PL fixtures today and Premier League table: How Manchester City and Liverpool result for Premier League go affect top four Liverpool manager Jurgen Klopp say no be only two teams wey fit win di Premier league dis season. Klopp say several teams fit win di League dis season, e dismiss report wey say di title race dey between im team and Manchester City. Tori be say for di past few seasons na City and Liverpool dey dominate di Premier League, and na Pep Guardiola City win di title for 2018-19 with 98 points to Liverpool 97. Di two teams go face each for Eithad stadium on Sunday 8 November. Sergio Aguero, Benjamin Mendy and Fernandinho go miss di game on Sunday. Meanwhile Liverpool fit welcome back dia defender Joel Matip, wey miss dia last two games sake of injury. Afta eight games na Southampton dey ontop di Premier League wit 16 points, but dem don play one game more dan di defending champions Liverpool wey dey second. If Liverpool beat City for Etihad, dem go return back to di top of di table. Man City demselves go remain for 12th position wit defeat but if dem win, di highest dem fit climb to na 5th position wit one game in hand. Tottenham wey dey fifth for table fit go top di table if Liverpool and Leicester lose dia games today di only team wey dis result go affect na Chelsea as dem go drop out of di top four position. Anything oda dan defeat today for Jose Mourinho team go see dem enta top four. Na only di top four teams for di league at di end of di season go qualify for Champions League next season. https://www.bbc.com/pidgin/sport-54861649 +politics Kogi lawmakers don impeach di deputy govnor Kogi State House of Assembly don impeach di deputy govnor, Simon Achuba. Na di Majority Leader for di House, Hassan Bello Abdulahi, announce tell tori pipo on Friday. Dis na afta di state chief judge, Justice Nadir Ajana set up committee to investigate oga Achuba, wey dem say disrespect di office of di govnor Yahaya Bello. Oga Hassan tok say dem bin collect di report, study am, come discuss am well-well before all of dem decide to impeach oga Achuba. Even sef im party di ruling All Progressive Congress follow suspend am. Dis impeachment dey come even as di state dey prepare for dia govnorship election next month wia Chief of Staff, Edward Onojia na Govnor Yahaya Bello running mate. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50102998 +sports Ralf Rangnick: Profile, trophies and important informate about Man United new coach "Manchester United confam di appointment of Ralf Rangnick as interim manager until di end of dis season. Rangnick take over from Ole Gunnar Solskjaer wey di club sack afta over two years in charge. Im appointment come eight days afta di sack of Solskjaer afta im poor run for seven straight matches. Man U football director, John Murtough for statement say afta dis season, Rangnick go continue as consultant for di club for two years. Born June 29, 1958, Ralf Rangnick, na 63-year-old German football tactician. Dem born am for Backnang and im major work na football development. Im na UEFA Pro Licence coach wey start im career as player-caoch for FC Viktoria Backnang fbetween 1983 and July, 1985. E later join VfB Stuttgart II as Manager between July 1985 and June, 1987. Im last job before im join Manchester United na head of sports and development for Russian club Lokomotiv Moscow. Ralf Rangnick don win eight trophies wit three clubs. Rangnick also win di Austrian Cup wit Red Bull Salzburg for 2013/2014 and 2014/2015 season - e lead Red Bull Salzburg to be Austrian Champions two times for di same season. German Super Cup Winner wit FC Shalke 04 for 2011/2012. E win di 2010/2011 German Cup wit FC Schalke 04. German League Cup winner wit FC Schalke 04 for 2005/2006 season. German Second Tier Champion wit Hannover 96 for 2011/2002. Manchester United don struggle since di start of di 2021/2022 season. Sabi pipo believe say di club wey dey 8th position for Premier League table need tactician wey fit use di players well-well. Dis na why Old Trafford management want make Rangnick dey for additional two years for consultancy role afta di season. According to di German, ""I dey happy to join Manchester United and focus on making dis season successful season. ""Di squad get plenty talent and great balance of youth and experience. ""All my efforts for di next six months go be to help di players fulfil dia potential, both individually and, most importantly, as a team. ""Beyond dat, I dey look forward to support di club long term goals on a consultancy basis.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-59463938 +sports West Brom vs Arsenal: Aubameyang and Bukayo Saka on target as Arsenal cruise to Carabao Cup victory Arsenal record dia first win of di new season as dem waya West Brom 6-0 for Carabao Cup. Di gunners cast aside di disappointment of Sunday 2-0 defeat to Chelsea. as dem prove too strong for di Championship side. Captain Pierre-Emerick Aubameyang mark e first start of di season for di gunners wit score hat-trick of goals. Before di game, Arsenal players and dia coach bin face criticism from fans as dem open di season wit back-to-back defeats to Brentford and Chelsea. Di gunners respond to dia critics wit fine first half performance wey see dem score three goals before di break. Aubameyang open di scoring for di 17th minute as e tap in rebound from close range afta West Brom goalkeeper, Alex Palmer save Bukayo Saka shot. Di Gabon striker double dia lead wit anoda tap in afta Nicolas Pepe shot rebound off di post come fall for im path. Aubameyang den turn provider as e assist Pepe just before half time. Arsenal look sharp and different from di side wey lose to Chelsea as dia pam pam passing cut West Brom defence open repeatedly. Na through dat one touch football di fourth goal come as Odegaard cooly set up Saka to put im name for di score sheet. Aubameyang complete im hat-trick as e curl one fine shot beyond Palmer for di 63rd minute. Arsenal substitute Alexander Lacazette wey just recover from Covid-19 na im score di sixth goal. New signing, Aaron Ramsdale mark im first match wit di club wit some good saves as e deny West Brom from scoring consolation goal. Fans go wait to see if di gunners go carry dis fine form into dia weekend game against Manchester City for Premier League. For West Brom, winning di Carabao Cup no go dey part of dia ambition dis season but dem go hope to continue dia bid to return to di Premier League after dem suffer relegation last season. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58336076 +entertainment Osaze Odemwingie: Peter Okoye, MR P ask pipo to pray for ex-footballer afta social medai qwanta "Nigerian Musician Peter Okoye don call for prayers for former Nigeria striker Peter Osaze Odemwingie. Dis wan na afta di two of dem bin do some kain gbas-gbos onto Instagram. Wahala start wen Odemwingie bin tell Peter to stop to dey ""rob pipo in broad day light wit im nonsense business,"" Afta di musician post one video for im page and write say ""who dey do dis new dance challenge dis Christmas December period? You dey on your your own."" For im reaction to di post, di ex-striker bin say ""You dey rob pipo for broad day light wit dat your nonsense business and now you wan even collect Christmas from dem, You no dey fear God? Okoye respond sharply with say im dey disappointed wit di footballer tok as im business na ""registered and licensed lottery platform just like every oda pesin here and abroad."" Okoye later post some more messages wia e ask pipo to ""pray for my namesake Peter Osaze Odemwingie, everything no dey well with am!"" Di mata vex peter and e reply am say im dey disappointed for wetin di footballer tok. He say di business di footballer describe as nonsense na im lottery business wey dey registered and licensed. Who be Peter Okoye? Peter Okoye na Nigerian musician, actor and businessman. He and im twin brother Paul Okoye bin dey sing togeda with di name PSquare, dem drop plenty award winning music before dem break up for 2017. Wen dem break up Peter Okoye take di stage name Mr P. Who be Peter Osaze Odemwingie? Peter Osaze Odemwingie na retired Nigerian professional footballer wey play as forward and winger. Dem born am for 15 July 1981 for Tashkent, Uzbek SSR, Soviet Union. Im papa na Nigerian (Peter Odemwingie Sr.) and im mama na Russian (Raisa). He grow up for Russia and Nigeria. Wen e be two years, im family move come Nigeria and e later return go Russia to complete im secondary education. Wen e turn 17, e come back Nigeria and begin play wit di professional Nigerian Premier League side Bendel Insurance. He play for di Nigerian national football team between 2002 and 2014, wia e represent di kontri more dan 60 times, e play for two World Cups and four Africa Cup of Nations, and he win silver for di 2008 Olympics. Odemwingie don also play for plenty international clubs like Lokomotiv Moscow, English Premier League club West Bromwich Albion, among others. He retire from professional football for 2019." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55157341 +health Ghana coronavirus update: Covid-19 recoveries for de kontri catch 10,074 Covid-19 recoveries for Ghana rise catch 10,074, one of de highest recoveries in one day. Ghana Health Service reveal say some 5,526 people be de latest to from de disease. De jump in recoveries be sake of de new discharging protocols wey WHO introduce. Sake of that health officials for Ghana dey count recovery and discharge together. Before dem dey do three tests before dem go discharge people wey test positive. But now dem dey discharge patients who be asymptotic after 14 days. Ghana record 514 new Covid-19 cases which push de total number go 13,717. Sake of de recoveries, total active cases now be 3,554. Meanwhile de death toll rise catch 85 after 15 people die in one day. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53126573 +sports Cristiano Ronaldo Instagram; Juventus star don reach top of social media rich list for di first time "Cristiano Ronaldo na di number 1 for Instagram rich list pass pipo like Lionel Messi and Justin Bieber. Ronaldo, wey get 308 million followers, get dis position sake of how much e fit cost to run sponsored post ontop im page. Di Juventus forward fit charge advertisers $1.6m (£1.2m) per post ontop im account, according to social media marketing company Hopper HQ. Na dis one im use displace Dwayne ""The Rock"" Johnson from di number 1 position. Dis na di first time wey Ronaldo don top di list, wey begin for 2017. Johnson, wey dey act inside di ogbonge feem Fast and Furious film franchise, get 250 million followers and fit command about $1.52m (£1m) per post, while pop star Ariana Grande with $1.51m per post dey number 3. Di only oda athelet wey dey di top 10, na Lionel Messi, wey become free agent dis week after im Barcelona contract expire, and im dey charge $1.1 (£798,011) per post. UK-based company Hopper HQ, wey dey run social media accounts on behalf of companies and individuals, publish di first Instagram rich list for 2017. Six women dey di top 10 dis year although dis na di first year wey pesin from Kardashian or Jenner family no dey top three. ""As Covid-19 continue to affect all our lives, e be like say Instagram na one of di few place wey di pandemic no affect negatively, and as more pipo dey use di app, some pipo go say di charging rate go peak dis year,"" tok Mike Bandar, co-founder of Hopper HQ. Top 10 celebrity rich list for Instagram Source: Hopper HQ" https://www.bbc.com/pidgin/tori-57692791 +sports Afcon 2019: Ghana vs Benin match result Di Black Stars dey play Benin Republic for dia group F opening match for Afcon 2019 inside (Ismailia Stadium, Ismailia, Egypt. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48761268 +health COVID-19 Vaccine: Ghana go receive 300,000 Sputnik V vaccines dis week "Ghana go receive some 300,000 Sputnik V vaccines dis week as part of second phase of de COVID-19 vaccination efforts. De country start dey face some supply challenge sake of global pressure on de vaccine manufacturers. Dr Asiedu Bekoe, Public Health Director for Ghana Health Service talk BBC Pidgin say ""despite de shortage across de world sake of de high demand for India, we go get de vaccines give Ghanaians."" ""We also dey rely on Sputnik vaccines, we no dey rely on only AstraZeneca"" he add. Ghana Health Minister, Kwaku Agyeman Manu talk journalists say sometime Sputnik deliver some 160,000 give Ghana already but dis week de country go receive 300,000 Sputnik vaccines. Ghana dey receive de Sputnik vaccines from Russia after some 1.3million vaccines wey dem send to Democratic Republic of Congo (DRC) but remain unused. Sake of de June expiry on de vaccines, UNICEF who dey lead de vaccine procurement and supply operation give de global COVAX facility dey redistribute de 1.3million vaccines to Ghana and some five other African countries." https://www.bbc.com/pidgin/56925748 +sports Lewis Hamilton: Formula driver suffer racist abuse online afta im British Grand Prix win "Lewis Hamilton don suffer racist abuse on social media afta im victory for Sunday British Grand Prix. Di incident come one week afta England footballers Marcus Rashford, Jadon Sancho and Bukayo Saka suffer racial abuse afta all of dem miss dia penalty for di Three Lions' Euro 2020 final shootout defeat against Italy. Hamilton bin receive 10-second penalty afta im collision wit title rival Max Verstappen during di first lap of di race, wey lead to crashing out of di Dutchman Mercedes, F1 and governing body di FIA condemn di abuse ""for di strongest possible terms"". ""These pipo no get place for our sport,"" na so dem write for joint statement. ""We want make dem hold di pipo wey dey involved for dia action. ""Formula One, di FIA, di drivers and di teams dey work to build a more diverse and inclusive sport, and dis kain online abuse we must torchlight am so dat dem know say e dey unacceptable and stop am."" Mercedes team principal Toto Wolff tell BBC Radio 4 Today programme: ""We don see am for football for di European Championship and di abuse no dey acceptable, and di same yesterday, and I still dey question am whether some pipo no just understand. ""Dis no dey acceptable and we go react to am."" Verstappen team Red Bull Racing say dem dey ""belly no sweet dem at all and dem dey sad"" sake of di abuse wey dem give Hamilton. ""Even though say we be rivals on-track, we all dey united against racism,"" di team tok for statement. ""We condemn racist abuse of any kind towards our team, our competitors and our fans. ""Excuse no dey for am, space no dey racism for our sport and those responsible dem suppose hold dem accountable."" Facebook, wey be say na dem get Instagram for statement tok say: ""Di racist abuse wey Hamilton susuffer during and afta di British Grand Prix dey unacceptable and we don remove some of di comments from Instagram. ""In addition to our work to remove comments and accounts wey constantly dey break our rules, we get safety features, including comment filters and message controls, wey mean say nobody fit see dis kain abuse. ""No single tin fit fix dis challenge overnight but we dey committed to di work to keep our community safe from abuse."" Dem carry Verstappen go hospital for precautionary checks afta im suffer impact of 51G for di crash, but dem later release am without any major injuries. Hamilton 10-second penalty see am drop to fourth place afta im pit stop, but di seven-time world champion fight back to overtake Ferrari Charles Leclerc wit two laps remaining to secure victory. Verstappen later say Hamilton dey ""disrespectful"" and ""unsportsmanlike"" for celebrating di win while di Dutchman dey for hospital." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57891740 +sports Bulgaria v England racism: Bulgarian football president Borislav Mihaylov don resign "Di president of di Bulgaria Football Union (BFU), Borislav Mihaylov, don resign. Bulgaria Prime Minister Boyko Borissov ask am to carry im load waka on Tuesday afta di racist abuse of England players inside di Euro 2020 qualifier for Sofia. Di referee of di Monday match, wey England win 6-0, stop di game two times because of racist behaviour by home fans, wey include Nazi salutes and monkey chants. Di BFU say ""dis na di consequence of di recent tensions"" but dem no mention di word 'racism' for dia statement. Meanwhile di Bulgaria national team coach Krasimir Balakov say im no hear any of di racist chant on Monday. ""E go pain me if e happun say na true... Me personally, I no hear di chanting,"" Balakov bin tok. Some days before di match, England players including Tammy Abraham, don already get one voice say dem go waka comot di game if dem hear or see racist behaviour, but although e happun, di Three Lions decide to play till di end. Marcus Rashford bin praise di Bulgaria captain for im ""courage"" afta di match ontop Twitter. Dis na afta Ivelin Popov bin go meet supporters for stadium to encourage dem to stop di racist behaviour. Earlier on Tuesday, di Bulgaria prime minister ""strongly condemn"" di behaviour of di fans and ask Mihalov to resign ""immediately"". ""Afta yesterday shame wey di Bulgarian National Team carri come and di bad result from our football, I don order di end of any relationship wit BFU, including financial, until Borislav Mihaylov comot from di position,"" hala Borissov" https://www.bbc.com/pidgin/sport-50049332 +entertainment BBNaija live eviction show today: Tolanibaj, Wathoni and Brighto don chop eviction from Big Brother Naija Season 5 "Tolanibaj, Brighto and Wathoni don become di latest housemates to chop eviction from di Big Brother Naija reality show. Ebuka put shock for di housemates body wen im ask Tolanibaj, Trikytee, Kiddwaya, Brighto, Prince, Erica, Lucy, Neo, Wathoni, Dorathy, Vee and Laycon to stand up. Afta some wait wit tensions high, di show host come confam Tolanibaj, Wathoni and Brighto as di housemates wit di least votes, so dia for, dem gats leave di Big Brother House. Tolanibaj wey be 27-years-old from Lagos State na media pesin wey bin serve as deputy Head of House wen Kiddwaya bin win di HOH challenge. Florence Wathoni Ayansi na fashion entrepreneur wey dey 29-years-old and she be single mother. She say her plans now wey she don comot from di show na to continue wit her fashion business and ""maybe start up TV show for pikin dem."" 29-year-old Ezekiel Bright alias Brighto get plans to ""get more certifications"" as im see imself as career pesin. Viewers of di show no waste time to begin tok about how dem feel about di Sunday eviction. For some of dem, dem feel say di eviction of wathoni come at di right time as she go reunite wit her son wey she don tok before say ""she dey miss"". While for odas, dem feel say Wathoni eviction don clear road for Dorathy and Brighto strike up relationship. Dat whole expectation no last long as Ebuka change am for all di viewers wen im announce Brighto as di third housemate on di night to leave di show. Dis announcement send fans into overdrive as dem bin no expect upto three pipo to go house inside one day." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53968627 +business "Suez canal blockade: ""Ever Given"" ship blocking Suez canal dey cost traders $9.6bn daily" "One giant container ship ""MV Ever Given"" wey hook for Egypt Suez Canal on Tuesday don become cause of concern for global trade as e block one of di busiest trade routes for di world. Di stranded ship wey im name na Ever Given dey stop di movement of at least $9.6bn (£7bn) of goods each day, according to shipping data. Dis dey work out at $400m an hour in trade along di waterway wey be important passage way between east and west. Data from shipping expert Lloyd List put di value of di canal westbound traffic for roughly $5.1bn a day, and eastbound daily traffic at around $4.5bn. Despite efforts to free di ship, expert's tok say e go take weeks to remove am. Bernhard Schulte Shipmanagement, di technical manager of di ship, tok say another attempt on Friday to re-float di cargo vessel no dey successful. A specialized suction dredger wey fit shift 2,000 cubic meters of material every hour now dey on site, and ""dem dey also make arrangements for high-capacity pumps to reduce di water levels wey dey inside di forward empty space of di ship and di bow thruster room,"" di firm tok on Friday. Bernhard Schulte add say two additional tugboats go arrive by Sunday to help di float operation to move di giant ship. About 12% of global trade dey pass through di 193km (120-mile) canal, wey connect di Mediterranean Sea to di Red Sea and e provide di shortest sea link between Asia and Europe. Di Ever Given ship wey Taiwanese company Evergreen Marine dey operate big, di length na like four football pitches and na one of di world biggest container vessels. Di 200,000-tonne ship dey capable of carrying 20,000 containers. Di way e take hook dey affect oda ships wey dey try pass through di Suez Canal. Di canal wey separate Africa from di Middle East and Asia, na one of di busiest trade routes for di world. According to Lloyd List tracking data, more than 160 vessels dey wait at either end of di canal. Dem include 41 bulk carriers and 24 crude tankers. Join wit oil, di sea traffic na largely consumer products like clothing, furniture, manufacturing components and car parts. BIMCO, one international shipping association, say di delays go continue to grow and e go affect supplies. In addition to delaying thousands of containers loaded wit consumer items, di stranded ship don also tie up empty containers wey dem suppose export. Efforts don continue to move di Ever Given, di 400m-long (1,300ft) container ship wey block di Suez Canal for Egypt since Tuesday. Dredgers don clear sand and mud away from di bow of di vessel, and dem don use tugboats and di ship winches to try move am. On Thursday, di owner of di giant container ship Japanese firm Shoei Kinsen, bin tok sorry for all di kasala di blockage don cause for oda vessels wey wan pass through di canal. Dem say dem dey try all dia best wit local authorities and di vessel operators, to find solution to di problem, but warn say e go dey very hard. If di delays dey short, most companies no go mind wait one exra day. But salvage officials say di congestion fit last for days or even weeks, wey go really affect global supply chains wey don already suffer sake of Covid-19 pandemic. Some companies go dey reason to fly replacement merchandise for higher value products, or use trains transport dem. Two major shipping companies, Maersk and Hapag-Lloyd, say dem dey find oda options to avoid Suez Canal. Egypt Suez Canal Authority (SCA) say dem dey do everything for dia power to refloat di ship wit tug boats, dredgers and heavy earth-moving equipment. Kitack Lim, secretary general of di international Maritime Organisation, say: "" I dey aware of di implications of di temporary closure of di canal, and I dey ask for patience from stakeholders across di supply chain as everyone works to ensure that di ship, di crew, cargo and di environment go remain protected.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56541085 +sports Man United vs Leicester City highlight: Kelechi Iheanacho score for Leicester City as dem draw 1-1 wit Manchester United Manchester United fail to close di gap on Champions League spot as dem only fit draw 1-1 wit Leicester City. Di Red Devils wey bin dey without Cristiano Ronaldo bin fall behind through Kelechi Iheanacho header on 63 minutes. United draw demsef level through Fred as di Brazilian pounce on loose ball afta Schmeichel don save Fernandes shot into im path. Di Old Trafford club for even fall further behind if no be VAR wey cancel Leicester City goal. James Maddison blast Iheanacho shot past David de Gea but di Nigerian according to VAR bin don foul Raphael Varane for di build up to di goal. One point from dis game no go do United any favours as dem don play two matches more dan Arsenal wey dey fourth place. Wit eight matches to play United dey sixth for table wit 51 points while Leicester City dey 10th wit 37 points. Di Foxes still get three more outstanding matches to play. 46 mins - Change for Manchester United. Shaw wey bin get injury don comot and Telles don enter. United restart di match and straight from dia Leicester City win corner. Di Red Devils clear di cross from Maddison. 49 mins - Scott McTominay collect Yellow card. 55 mins - Rashford don come on in place of Scot McTominay wey bin don see yellow card. 63 mins - Goal! Kelechi Iheanacho give Foxes lead for Old Trafford Di goal wey see Iheanacho connect wit Maddison cross wit im head na Leicester first shot on target for dis match. 64 mins - Substitution: Daniel Amartey ON for Johny Evans. 66 mins Goal! United equalise through Fred. Di Brazilian convert rebound afta Schmeichel don save Fernandes shot. Manchester United 1-1 Leicester City. 71 mins - Iheanacho wit anoda chance to give di Foxes di lead again...di Nigerian loop im shot ova di onrushing De Gea. 72 mins - A minute later, di Spanish goalkeeper produce anoda good save to deny Fofana. Wow! 75 mins - Nemanja Matic don replace Paul Pogba for United. 80 mins - Goal for Leicester City? Maddison don give di visitors di lead again. Di midfielder fire di shot into di net from Iheanacho pass. But di referee dey go check am for VAR. Afta one or two glances, Andre Marriner say no goal as Iheanacho bin foul Raphael Varane. Still Manchester United 1-1 Leicester City. 84 mins - Tielemans try im luck from outside di box but di shot no get power, De Gea catch am. 90 mins - Leicester City substitutions. Daka and Choudhury ON, Mendy and Iheanacho OFF. 90+2 mins - Sancho shoot wide afta Amartey bin slip. 1 min - Leicester City take di first kick of di game as di match don start. Andre Marriner na im be di referee for today. 2 mins - Leicester win freekick near United eighteen. Barnes head over Maddison cross from di freekick. 5 mins - Luke Shaw collect di game first yellow card as im bring down James Justin. Di ref consider di foul to be serious challenge. 10 mins - Fred try to play Elanga clean through but Evans block im through pass. 11 mins - Leicester play dioa way through United defence wit neat passing, Barnes finally shoot but im shot go wide. 16 mins - Yellow card for Fofana wey bring down Elanga. Fernandes try to find Maguire but di big man no fit connect wit di shot. 20 mins - Almost a quarter of di match don pass and both sides neva create much. 26 mins - Save! Schmeichel use im legs to stop Bruno Fernandes ground shot afta di Portuguese don dey through on goal. First big chance of di match. 30 mins - Yellow card for Tielemans. 35 mins - Leicester City almost take di lead through Harvey Barnes. Di midfielder glanced shot from Maddison cross go over. 40 mins - United wan make early substitution, Luke Shaw look like say im dey injured. Alex Telles dey ready to replace am. 42 mins - Afta some treatment, Shaw go continue. 45 mins - Linesman flag Fernandes don enter offside. Di ref don add three minutes extra for dis first half. Possession - Manchester United 56% - 44% Leicester City United XI: De Gea, Dalot, Varane, Maguire, Shaw, McTominay, Fred, Fernandes, Pogba, Sancho, Elanga. Subs | Henderson, Telles, Jones, Lindelof, Wan-Bissaka, Mata, Matic, Lingard, Rashford. Leicester City XI: Schmeichel, Justin, Evans, Fofana, Castagne, Tielemans, Mendy, Maddison, Dewsbury-Hall, Barnes, Iheanacho. Subs | Söyüncü, Albrighton, Pérez, Amartey, Choudhury, Ricardo Pereira, Daka, Jakupovic, Lookman. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60967575 +politics """Trump debate Biden"": US presidential debate 2020 claims by Donald Trump, Joe Biden for Cleveland na true? Reality Check find out" "America President Donald Trump 2020 re-election campaign team don claim say na Oga Trump dey lead di first presidential debate between him and im m Democratic Challenger Joe Biden. Campaign manager, Bill Stepien say Trump turn in di greatest debate performance for presidential history. But tori be say some viewers consider Tuesday night Cleveland presidential debate as one of di most disorganised White House debates in years. Di 90 minutes debate hot as di candidates no gree on top any mata, from di state of di economy go di way goment take handle di coronavirus pandemic. Reality Check pick some of di things dem claim wen Trump debate Biden and fact check am whether di claim na true. Trump: ""We build di greatest economy for history"" Verdict: He dey wrong: E get time for US history wen di economy dey stronger. President Trump claim say before di coronavirus outbreak, im goment build di greatest economy for di history of America. He say for history, di kontri economy grow well, record low unemployment and remove millions of Americans comot from poverty. Na true say di economy dey do well was doing well before di pandemic - continuity of wetin former President Obama administration start - but e get time wen e dey stronger.er. The economy under Trump in six charts Verdict: E dey correct small. But if dem check coronavirus deaths per capita, e get some kontries where dia case worse pass US. Oga Biden criticise President Trump for di way e take manage and respond to coronavirus. ""In fact we get 4% of di world population, 20% pipo don die,"" di former vice-president tok. According to di figures, he dey right. US population na around 328 million, wey be just over 4% of di 7.7 billion population of di world. 205,942 pipo don die sake of coronavirus deaths for di US, according to di latest John Hopkins University data. Di total number of deaths recorded worldwide na 1,004,808. If we calculate am like dis, America get about 20% of Covid-19 deaths worldwide, although di way kontris take dey record dia figures dey different. Fact check of wetin di presidential candidates claim Verdict: Studies neva discover or show evidence of plenty magomago, although very small cases dey. President Trump tok say increase in postal ballots go cause di kain magomago wey pipo neva see before. Sake of coronavirus pandemic, plenty US voters go use postal voting vote for dis year election. Di president don sama warning plenty times say dis method no pure. Small cases of magomago dey reported including recent examples for North Carolina and New Jersey. For September, di US Department of Justice release statement about one incident wey happun for Pennsylvania in where ""nine military ballots waste"" and said seven of them ""na vote in favour of di presidential candidate Donald Trump"". But even wit all di cases, plenty studies no show evidence of any widespread fraud. Di rate of voting fraud overall for di US dey between 0.00004% and 0.0009%, according to one 2017 study by di Brennan Center for Justice. Verdict: No ogbonge answer to dis. Di candidates quanta over how many pipo for di US get pre-existing medical conditions, wey no go make some Americans dey covered by private medical insurers. Oga Biden about 100 million pipo getpre-existing conditions, but President Trump say di number dey ""totally wrong"". So how many dey? No ogbonge answer to dis. According to di US goment Department of Health and Human Services, between 50 and 129 million Americans wey neva old get some type of pre-existing health condition. Other organisations get different estimates. The Center for American Progress believe say e dey higher, at 135 million pipo under age 65. Verdict: ""Very, Very low chance"" na im dey if any approved vaccine go dey ready by di end of October, di chief scientific adviser to di US vaccine programme tok. President Trump for di debate tok say vaccine go ready for US in some weeks. However, Dr Moncef Slaoui, di chief scientific adviser to di US vaccine programme, say di chances say approved vaccine go ready before di end of October dey slim. Meanwhile, Dr Anthony Fauci, di kontri top infectious disease expert, bin predict say America go know if dem get safe and effective vaccine by November or December dis year. He tell Senate committee hearing dis month say Americans go get enough vaccines by April. Verdict: Dis one no correct, according to di figures. Democratic candidate Joe Biden tok say even before Covid-19, ""manufacturing go down"". Di pandemic no get impact on dis sector. As of August, manufacturing jobs for America no reach 237,000 wen Trump take over office for 2017. But before di pandemic, President Trump don add almost half a million manufacturing jobs during im first three years in office. Verdict: xxxx Normal copy Verdict: Di average monthly cost of prescription drugs fell slightly bin fall for di year to August 2019, but e rise again. Oga Biden claim say President Trump ''no reduce di price of drug for anyone"". But according to di Bureau of Labor Statistics Consumer Price Index (CPI)- wey dey measure di cost of household items for America - di average monthly cost of prescription drugs fell by 0.3% for di year to August 2019. Dis na di first time price go reduce over a 12-month period since 1973. While average drug prices rise by 1.5% over di following year, under President Trump di average rises bin dey lower pass wen President Obama dey office. The CPI no be di most reliable way to measure drug prices, as e most of di time include drugs pipo dey use well-well, and dem dey cheap. It is less likely to include newer or less-prescribed drugs, wey dey more expensive and get higher price increases. Read more from Reality Check Send us your questions Follow us on Twitter" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54351935 +sports Premier League: BBC Sport pundits predicts who go win & finish top four Defending champions Manchester City dey go for hat-trick of titles dis season - but who fit stop dem from winning three in a row? Dat na di next target for City boss Pep Guardiola, im don already achieve di feat for Spain (Barcelona, 2008-11) and Germany (Bayern Munich, 2013-16) e win a total of four league titles in six seasons at City. Liverpool na City closest rivals last season, dem finish only one point behind, but di koko now na if odas fit challenge dem dis time around? Dis na start of a new era for Manchester United under Erik ten Hag but, afta dem finish sixth last season, di big question na say if dem fit return to top four, or sustain a serious title bid for the first time since di last time dem become champions for 2013? What about Chelsea chances to challenge for di title afta di wahala di club get off di pitch for 2021-22? And Tottenham chances to build on dia fourth-place finish? Then Arsenal to get back into the Champions League places for di first time since 2016? Or odas teams fit enta dis mix too? We ask BBC TV and radio pundits to pick dia top four, and explain dia selections. Dis predictions na onto how each squad dey as at Thursday, 4 August, wit more than three weeks to go until transfer window close at di end of August. Na six teams feature for di forecasted top fours, but na only Manchester City and Liverpool feature for all 23. In terms of who go win am, Manchester City na di favourites wit 13 votes. while Liverpool get di oda 10. (we use di system of 4 pts for 1st place, 3 pts for 2nd, 2 pts for 3rd and 1 pt for 4th) Martin Keown: Dis season go different from wetin we don experience before . E go dey in two halves. Jermaine Jenas: A good start dey more important dis season because we no know yet how di World Cup go affect di players wey go, or di ones wey no go. Stephen Warnock: E dey very hard to call di title race dis year. Imagine say you dey top and dey cruise at di start of November -dat normally na di start of your title charge - but dis time you fit see players pick up injury or lose form for Qatar and by di time you restart di season you don lose all your momentum. Nedum Onuoha: You want your players to stay sharp, but not too tired. Selfishly, I imagine say most club managers go prefer for dia players to come back afta di group stage so dem fit get two or three weeks to prepare for di rest of di season. Glenn Murray: E fit hinder City twice? Dem dey start slow sometimes for August, so e fit happun again for December. I don't see it though. Everyone know say dis break go happen and dem go dey ready for am, especially di top teams. Ashley Williams: Whoever handle dis di best go be a big factor for di title race, but di top two go into it wit so much detail about everything and dem dey normally get am right. Micah Richards: E go dey very tight wit Liverpool yet again, but I just feel say Erling Haaland and also Julian Alvarez fit be di difference for City. Nedum Onuoha: Both players dey very good, but I feel say dis year maybe dey come too soon for dem. Di difference between City and Liverpool dey very small. Jermaine Jenas: Wit Fernandinho leaving, dem don lose dia leader for dressing room and, overall, few uncertainties dey wit City than Liverpool. City get a lot of resting on players wey neva do am for dem yet and historically we know say e go take a while to fit into dia team. Haaland and Alvarez gats come in and blend in straight away, wit Raheem Sterling leaving, Jack Grealish gatz produce more dis season. Michael Brown: City don already make some great signings and dem want get a left-back in too. With their strength in depth, dem suppose strong pass Liverpool. Glenn Murray: I dey excited to see Haaland, of course. But I no know how e go work wit di way City dey play and dey pin teams in - especially against lesser sides for Etihad. I don dey for those games and sometimes you go get got 10 opposition players around dia own area. No space at all and im no go don face that problem before. City no dey put di ball inside di box, so wetin im go do? Ashley Williams: E go take City time to figure out how im go fit in, but e go come. Whoever dem put down di middle last year bin get plenty chances, so di same go happen for Haaland, although e go dey patient because di ball no go come to am as quickly as im dey used to. Izzy Christiansen: Haaland go give dem a more direct way of playing, e mean say dem go dey able to kill games off quicker. Jonathan Woodgate: City bin win last year without a striker and now dem get Haaland, wey be world class. e sure for dem - dem don improve, so dem go win am again. Jonathan Woodgate: Liverpool go miss Sadio Mane badly because im bring so much to di team wit im closing down as well as im goals. Without im, I no see how di title race go dey close as e bin dey last season - I feel say City go win di league by a much wider margin. Martin Keown: Liverpool na di best pressers for world football, and Mane na best , so for dem to dey better without am e go hard for me to take on board. For City to dey better wit a proper centre-forward, I go accept. Dem no feed Haaland di ball for Community Shield, but dem get intelligent players and dem go adapt. Jermaine Jenas: I bin dey think about Mane going and how big di loss be - dem don lose one of di best players for Premier League. But it freshens dia team up and dem no get anything to worry about squad-wise. I dey see Liverpool younger players like Harvey Elliott and Curtis Jones to contribute a lot more dis season, and dem get di best defence for di league. Leon Osman: Losing Mane fit dey big, but im replacement fit dey bigger - we just no know yet. Whatever happens wit Darwin Nunez, a front three of Luis Diaz, Diogo Jota and Mohamed Salah go dey difficult to stop, but I still see dem falling short of City. Matt Upson: Like City, Liverpool get new striker wit Nunez, but dem get a bit more clarity wit dia system. Dem dey use to playing di ball forward quickly, wey suit a centre-forward like him and dem dey more direct in di way dem dey cross, di balls ova di top and down di flanks. Danny Murphy: I expect Haaland to settle quick pass Nunez, only because e get more experience, but dat probably dey a little bit unfair on Nunez because straight away im dey look like a real threat and like player wey get plenty energy. Dem dey go toe to toe wit City again. Stephen Warnock: You only need to watch di quality and intensity on show for di Community Shield to see how good City and Liverpool dey - and why no-one go dey close to them again dis season. E dey between those two again and di big thing for me na how much City go miss Sterling and di influence and impact im get. E dey always pop up wit key goals and assists and dem for no win di last game of di season - or di title - if not for him. Jermaine Jenas: As good as Liverpool season be last time, dem bin suffer a lot of pain as well towards di end and dat kind of stuff go ginger you up for di new season. We see am happen afta dem miss out to City in 2018-19 and dem come back flying. This time, I think those memories of missing out on di title and losing di Champions League final dey di mind of these players as well. Dat hunger fit be di thing wey go get dem over di line. Glenn Murray: We don already see Tottenham progress since Antonio Conte take charge for November and you know say im go make sure say dem work hard again. Dia firepower dey almost unmatchable and im style of play dey very structured - dem no go concede many goals. Pat Nevin: If anyone dey capable of breaking out of di pack na Spurs because of how well dem buy players. Michael Brown: Di squad Spurs get now dey very good. Di only question I get n about dia three centre-backs and whether dem dey strong enough defensively ova di course of di season. Leon Osman: Dem fit be di dark horses dis year if dem sort out dia defensive issues. Di addition of Richarlison to dia attack make dem more balanced side. Someone oda than Son Heung-min to run in behind make dem rival any attacking team for di league. Add for di leadership of Conte and dem fit make a fist of am - if dem fit figure out a way not to be so 'Spursy'. Sue Smith: Dem buy a lot of strong and aggressive players so dem go dey tough dis season. Dem go dey hard to beat. Jermaine Jenas: Conte signings don elevate dis team to another level.e depend on dem if dem fit find di performances and di rhythm dem bin get last year, but I dey predict a reasonably comfortable third-placed finish for Spurs. Di only reason I dey put them on di title race na because, unlike City and Liverpool, I no sure if dem fit win 14 or so games in a row. Dem fit stay unbeaten for dat long, but I no see dem go on a run wia dem dey win every match Matt Upson: Chelsea dey rebuild wit change of ownership and lot of movement for dia squad. A bit of uncertainty dey around dem. Martin Keown: Last season top four go take some shifting, but potentially Chelsea look di most likely to fall out of sake of di players wey don comot . Antonio Rudiger na massive loss for back. Stephen Warnock: Chelsea need a striker and dat na di reason dem no dey my top four. Pat Nevin: For Chelsea to get good season, dem need three things to happen: Kai Havertz need to play well and their full-backs gatz stay fit - Reece James and Ben Chilwell bin dey out for long periods last season and dem bin miss dem badly because dat na where plenty of dia creativity dey come from. The third thing na say dem need to sign another major centre-back to go with Kalidou Koulibaly. Na wetin dem dey try do, but if dem no get one, dem no go fit compete. Izzy Christiansen: With Thomas Tuchel in charge, I see Chelsea dey struggle wit dia form. Sterling na smart signing e go give dem sometin different. Danny Murphy: Dem get some new faces and e go take a while to settle but I be big fan of Tuchel and I feel say im be very intelligent manager. I still tink dia squad dey full of quality players and I no think dem go get di same bad spell like last season, so I feel say dem go do beta dis time. Dem sign some good players, I expect dem to sign more. Jermaine Jenas: E hard to go against Chelsea finishing for di top four. but if dem bring in Frenkie de Jong from Barcelona as well as Marc Cucurella, things go start to look very different. Whoever come in, dem go get wetin dem need for di transfer market and Tuchel go make dem play di way im want. Dion Dublin: E bin dey very close to call between dem and Tottenham for fourth, I don speak to di new United manager, things go dey very different there. Dem go come good soon. Nedum Onuoha: United basically fall apart for di second half of last season, but e dey look like dem dey in di right direction now wey Ten Hag dey in charge. Jermaine Jenas: United dey depend on players wey don dey quiet for dem so far, players like Jadon Sancho and Marcus Rashford - wey bin no dey form last season - but you gtaz realise say dem bin no dey organised for most of last season. Dem bin no get set way of playing, but Ten Hag and im assistant Steve McClaren go change am and make sure each player know wetin dia job be. When footballers get dat clarity, good things go start to happun. Dem go dey in the mix for fourth but, compared to everyone else, I no think say dia squad dey good enough to make am Glenn Murray: I dey expect improvement from United, but dem still dey far from di Champions League places. Chris Sutton: Na bigger job to get dem into di top four than for oda team going for those places. Jermaine Beckford: Dem go dey extremely fortunate to make a European spot through di Europa League. Jonathan Woodgate: E go dey difficult for Ten Hag. Di Cristiano Ronaldo situation dey go on one side and e go affect di squad. E no go dey on dia pre-season tour and e no go dey 100% fit for di start of di season. Will Ronaldo settle to sidon for bench? I no think so… Leon Osman: United get alot of ground to make up, but Ten Hag fit be di man to do am. Ronaldo fit dey key - or e fit leave. Ten Hag need to decide quickly as im need a united camp without distractions. Stephen Warnock: If United keep Ronaldo, I feel say dem go struggle. E go just cause problems because I no think e go play for Ten Hag system. Dia top-four chances dey hang on dat. Jermaine Jenas: Dis no be Ronaldo for di peak of im powers, like wen im bin win di Champions League wit United for 2008 then im bin dey indispensable and get so much influence on di team. But dis Ronaldo dey vital in terms of im goal contribution to United. If dem lose di 24 goals im bin score for them last season, who go score them? Nobody else dey that team wey I go back to reach 20 goals on dia own, so dat go be my biggest concern if im go. Jermaine Beckford: Arsenal just look like dem get a really good pre-season and look like dem dey happy and energised, wey dey vital. Matt Upson: I consider West Ham as well, and whether dem fit progress again afta last season, but I go for Arsenal to finish fourth because dem don dey rebuild for much longer. Ashley Williams: Arsenal dey look stronger and stronger. Yes a team like Aston Villa fit hit a golden patch and challenge and I think Everton fit do well dis season too - Always one team go surprise everyone - but Gunners na di most likely team to break into di top four. Jonathan Woodgate: I love di players Arsenal buy and dem go dey close to di top four again dis season. I no see West Ham doing as well dis time and although pipo fit talk about Newcastle if dem start well, I feel say dem go make Europa League - dat go be successful season for dem. Michael Brown: Arsenal dey good form and wit dia new signings. I no think dia squad dey strong as di teams wey bin finish above dem dis time, but dem fit surprise everyone dis season. Stephen Warnock: I be huge fan of Gabriel Jesus. Im fit be di signing of di season. Nedum Onuoha: Jesus arrive wit a point to prove because im bin dey di background a bit for City. Im be di main man now and I expect am to do very well. If im fit lead di line and pass on di experience of wetin e take to dey successful for Premier League, den Arsenal go dey very competitive dis year. Leon Osman: Signing Jesus fit be di game-changer for dem. A guy wey go do well at di top of dat young developing team. But dat na di issue - dem still dey grow and I no dey sure if dem don ripe yet. Jermaine Jenas: Dem look like a team wey dey go in di right direction, but dem still neva convince me. I feel like dem go start well. A lot of pipo dey concerned about dia first game for Crystal Palace and I feel say dem go win, but I no dey sure if dem get enough to sustain di momentum for di season? Martin Keown: I dey worried say di pre-season bin go too well for Arsenal. If Arsenal lose dat first game, all of dia good work for preseason don go. https://www.bbc.com/pidgin/sport-62319132 +politics Mike Pence: Wetin make Nigerians compare US Vice President Mike pence wit Prof. Yemi Osinbajo "Di actions of US Vice President Mike Pence to President Donald Trump claim say wuruwuru full di 2020 US Presidential election wey lead to im defeat for di polls don make pipo begin scratch dia head. Oga Pence comment wey somehow no agree wit dat of di president to reject di confirmation of Joe Biden as di next president don make Nigerians dey compare am wit dia own Vice President Yemi Osinbajo. Many Nigerians hail am for im courage to stand against di President. President Donald Trump bin tell im supporters say if Vice President support dem, dem go win di presidency but Pence, insist say im no fit change di results of di election despite pressure from di president, According to di 12th Amendment of di US Constitution, di Vice President go serve as di Presiding officer wen Congress begin dey count di electoral votes for di President of di United States states. For inside statement, im say e position no give am power to reverse di 2020 election results and Joe Biden victory. Im say American pipo don choose dia president and dem get every right under di law to demand free and fair election. Di statement dey come as President Donald Trump continue to pressure im vice-president to overturn di result, e tell im supporters for im rally for Washington DC say im go dey ""very disappointed"" in Pence if e no follow im call to reject di election results. Pence don face intense pressure from Trump and plenty Republican lawmakers to push back on Biden win. But for im statement, Pence tok say na im ""considered judgment"" and dat di US Constitution no support am. ""Di Presidency belong to di American people, and to them alone,"" Pence write. Plenty Nigerians don enta social media to compare Mike Pence and Professor Yemi Osinbajo on top wetin dey happun between him and im oga, Donald Trump. Some oda pipo believe say di comparison no make sense at all." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55576491 +sports Raheem Sterling: Jesus, Ake, Lukaku, De Jong, Bailly - all di latest transfer rumour Tottenham dey hope to beat north London rivals Arsenal for di race to sign Manchester City 25-year-old Brazil striker Gabriel Jesus wit di offer of Champions League football. (Mirror) Manchester City and England forward Raheem Sterling, 27, don dey ask pipo about life in west London as im dey consider interest from Chelsea. (Athletic) City don turn down Chelsea initial bid of £21.5m for Sterling. (Fabrizio Romano) Chelsea fit also enquire wit Manchester City about 27-year-old Netherlands defender Nathan Ake. (Telegraph, subscription required) Chelsea and Belgium striker Romelu Lukaku, 29, dey set to return to Inter Milan on loan for fee wey dey around £8.5m plus add-ons wey di two clubs don agree. (Mail) Manchester United dey consider fresh bid for 25-year-old Barcelona and Netherlands midfielder Frenkie de Jong. (Fabrizio Romano) Wolves and Portugal midfielder Ruben Neves, 25, dey United list of possible options if dem fail to sign De Jong. (Fabrizio Romano, via givemesport) Newcastle don dey offered di chance to sign Ivory Coast defender Eric Bailly, 28, from Manchester United. (Mirror) Di Magpies also must pay £50m to sign 22-year-old Bayer Leverkusen and France winger Moussa Diaby according to wetin di German club tell dem. (Sun) Portugal star Cristiano Ronaldo, don welcome Manchester United quest to sign new striker. (Express) Netherlands manager and former Manchester United boss Louis van Gaal reportedly play a part in stopping Ajax Dutch defender Jurrien Timber, 21, from moving to Old Trafford. (Marcel van der Kraan, Sky Sports) Di agent of Chelsea and England midfielder Ruben Loftus-Cheek say former Blues boss Maurizio Sarri dey interested in signing di 26-year-old for Lazio. (Metro) Ajax don set 40m euro (£34.3m) asking price for Sebastien Haller, Borussia Dortmund also dey interested in di 27-year-old Ivory Coast forward. (90min) https://www.bbc.com/pidgin/sport-61862485 +politics Challenges William Ruto presidency go face to govern Kenya "Deputy President William Ruto don dey declared winner of Kenya presidential election amid dramatic scenes on Monday.\n\nBut wetin be di challenges ahead for di man wey go succeed President Uhuru Kenyatta? Ruto narrowly beat im rival, Raila Odinga, taking 50.5% of di vote, according to di official results IEBC declare. Monday announcement bin delay in di middle of kwanta and allegations of vote-rigging by Odinga campaign. Four of di seven members of di electoral commission no gree to endorse di result, saying e dey ""opaque"".\n\nHowever, William Samoei Ruto get task ahead as di next president of Kenya, if noting change by 30th August, 2022.\n\nSo wetin be di challenges ahead? Public debt bin increase to a record high of 8.56 trillion shillings wey dey equal to $72 billion for May from 1.9 trillion shillings e be for 2013 when President Kenyatta administration take office. According to economists, dis situation fit make di kontri enta di list of kontris wey di IMF no go give loan. According to di Ministry of Finance, Kenya use about 57% of di national tax for di last fiscal year take pay debts. Last month, MPs increase Kenya debt go 11% and dis help di goment finance im budget for di next 12 months. Prices of goods and services rise quickly in more than five years. Dis na di situation wey don force goment to introduce food and fuel subsidies. Di rise in commodity prices don make am difficult for Kenyans to continue dia lives as usual. For example, two-kilogram packet of corn flour don reach two dollars from 1.2 dollars e dey in di past three months. Dat na 67% increase. Dis move by goment to set subsidies and allow corn meal traders to import corn from neighbouring countries no still dey successful even as dem reduce di price of these products to one dollar for a two-kilogram bag. Russian war also contribute well-well to di plenty money wey climb on top di  price of commodity. And about 30% to 50% of Kenya wheat flour dey come from Russia and Ukraine. Ukraine sell less than 60% of wheat dis year compared to 2021, one issue wey cause di price of wheat and dia products like bread to rise. Di rate of youth unemployment for Kenya increase for di first quarter of 2021, compared to di previous quarter. For di age group between 20 and 24 years, di rate dey for 16.3% from 15% e be for di quarter of 2020. Among 15 to 19-year-olds, unemployment rate rise to nearly seven percent, afta e reach a record low of 2.8 percent for 2020. About 5.2 million dey unable to find employment while di labour force dey increase by 1 million pipo every year according to di World Bank report. Kenya economic growth don reach 5.5% in 2022 and e dey expected to reach 5.2% on average between 2023-24. Di growth rate, although still dey strong, go dey moderate following di remarkable recovery for 2021 from di worst economic effects wey corona epidemic cause, when di kontri economy grow by 7.5 percent, wey be higher rate dan di average growth of economy for di African region and di Sahara desert of 4%. Corruption na often one of di biggest problems for Kenya. Kenya head of public service, Joseph Kinyua, estimate say dem dey lose one-third of di national annual budget to corruption, while accounting firm KPMG LLP say abuses and crime plus bribery and bid rigging dey consume about 10% of a national income of $95 billion annually. President Uhuru Kenyatta last year tok say dem dey tiff about 2 billion shillings every day from di goment. Kenya score only 30 out of a possible 100 for im anti-corruption efforts for Transparency International 2021 Global Corruption Perceptions Index. Although e get small improvement from di 26 points e score for 2016, Kenya still dey below di African average of 32." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd19plyg7qeo +sports Paul Pogba broda promise to reveal explosive about di Juventus star "Paul Pogba broda don surprise di football world afta e upload different videos on im social media account. Mathias Pogba, di broda of di Juventus star, post videos in four languages, French, English, Italian and Spanish. Inside di videos, e dey read from one sheet of paper wia e promise to publish explosive revelations about Paul. Mathias say e dey willing to share information about im broda Paul wey im club, fans, and kontri need to know about. E also promise to tell di world tins about Pimenta and Paris Saint-Germain star, Kylian Mbappe. International news media dey report say Paul Pogba, don bin already tok say e be di target of extortionists. And e don issue one statement through im lawyers saying dat di videos dey “unfortunately no surprise"". Mathias, tok for di videos wey im post for im different social media account say di revelations dey likely to dey explosive, but e no give any further informate to back up wetin e dey tok. Mathias kontinu to explain why e dey carry out dis action. ""Hello evrione, I be Mathias Pogba, I announce say I go soon make big revelations about my broda and Rafaela Pimenta, im lawyer, im friend, im confidant and di one we call today di most powerful for football, and di one my broda call im second mother,"" Mathias tok. ""I dey make dis video today because I believe say di French, Italian and English piipo plus my broda fans and even more so di French national team, Juventus, im teammates and im sponsors deserve to know certain things in order to make decision on weda e deserve dia admiration, respect and affection. ""If e deserve im place for di French national team and di honour of playing for diWorld Cup, if e deserve to be starter for Juventus and if e be reliable pesin, wey any player deserve to get am by dia side and, finally, if e dey worthy to be representative and role model for di youth of di world, for di working class and di big brands."" Mathias say e no go only discuss about im broda but e go also tok about Pimenta, and Paris Saint-Germain star Kylian Mbappe. ""Wetin you go learn about Rafaela Pimenta, di lawyer of di famous Mino Raiola, go give you idea of her professionalism, her loyalty and weda she deserve to take over from Mino Raiola,"" e add.\n\n""Dis go let di players of di team and dia clients know if she deserves to represent dem and look afta dia interests and future players looking for agents for dia future contracts. If Rafaela Pimienta and her team go really care about dem and dia families and if dem be viable options?\n\n""I think wetin I get to say fit interest a lot of pipo. In addition, I go also tell you things about Kylian Mbappe, di world football star, and there go be elements and many testimonies to confirm my words. All dis dey likely to be explosive and make a lot of noise."" Paul Pogba move from Manchester United to Juventus on a free transfer dis year, and win di World Cup with France for 2018. Paul Pogba say e be target of extortion and threats from organised gang. Di Juventus and France midfielder issue one statement through im lawyers on Sunday saying dem don report di mata to di authorities. News agency AFP, citing one source, say French police don open investigation. ""Dem dey in addition to threats and extortion attempts by one organised gang against Paul Pogba,"" di statement read. ""Di competent bodies for Italy and France get di informate a month ago and no further comments in relation to di investigation wey dey go on.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cydepvpr267o +sports Cameroon vs Ethiopia: Afcon 2021 prediction, preview as Indomitable Lions look to quench Cameroonians hunger for clinical victory against Ethiopia "De Indomitable Lions of Cameroon di carry about 20 million Cameroonian fans weh na also coaches for dia shoulders as number 33 Africa Cup of Nations start. De first match of de 33rd Africa Cup of Nations, Cameroon 2021, against de Stallions of Burkina Faso for Group A show how fans di hungry for see Lions win wit style. Captain Aboubakar Vincent weh e score de two Cameroon goals from penalties, say even though deh win, dia play no convince fans. Though Cameroon kam from one goal down, win Burkina Faso 2-1 on penalties, fans dia joy no complete as deh bi wan see de team score clinical goals. Antonio Conceicao and e squad go meet Ethiopia wit de advantage say de pick three points for first match. Ethiopia bow to Cape Verde as dem lose 1-0. But, Ethiopia no go just let de Lions tear dem wit no fight as deh go do everything for pick three points to raise de hope of dia kontri. ""De match go tough if we consider weti happen for first group games. Na true say Cameroon win and Ethiopia loss dia first game, we know say na match weh e get stakes becos de winner go get beta chance for qualify for next round', Lions supporter, Sule Njing tok. Cameroon and Ethiopia meet very few taims. De two teams meet for Afcon for 1970, when Cameroon beat Ethiopia 3-2. Since weh Ivory coast beat Cameroon for 2015, no kontri nova try dem for group stage for de past seven years. Walia Ibex (Ethiopian National Team) di witness goal drought for de past nine years and deh nova win any Afcon game. Cameroon di bank on dia star players laik Choupo Moting and odas weh deh di sell dia craft outside Cameroon. Ethiopia squad only two players outside de kontri, El Gouna Shemeles Bekele and Mujib Kassim for JS Kabylie, Algeria. Striker, Getaneh Kebede go captain de East African team against Cameroon, Thursday, January 13. Cameroon and Ethiopia no get any Covid-19 issues as deh ready for dis second match for Group A. Cameroon midfielder Samuel Oum Gouet ahead of di match sey weti bi important na for de Indomitable Lions to grab di three points. ""We di prepare for dis game, na different and special game,"" E tok. ""Weti bi important na for grab de three points. Ah no know how, but ah know say we get for win dis game. For manage pressure, me and my mates just put we eyes and head for football, noting more"". ""We prepare well, we know say Cameroon get strong squad wit experience, but we bi ready for win,"" na so Mesud Mohammed Mussa of Ethiopia tok for di pre-match press conference. ""We team suffer defeat for first game, wit one man down, dis stress player mentally and physically. We don put de game for back. ""We strong for head and we don recover physically. We know say Cameroon na strong team, we love dem when deh represent Africa wit player laik Samuel Eto'o but tomorrow we go play good game."" Fans dem say deh di mobilize for go support Lions for Olembe stadium. ""Lions di make we proud and we get for support dem. We support dem for first match and dis match against Ethiopia no go bi different"", Peter Ngala, Lions fan tok. For Ngala, Lions go win Ethiopia 2-0. While Ethiopian fan Joseph Paul say di game go end 2-1 as win for Walia Ibex." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59976769 +politics Putin and Biden Summit: Five tins Russia and America leaders discuss for Switzerland "Russian Presido Vladmir Putin don hail American President Joe Biden for dia summit for Geneva say im dey well-balanced. Dis one na afta dem bin tok for four hours from topics wey start from nuclear arms control to American accuse of Russia cyber attacks. Putin bin throw hint say e fit dey possible say dem go get deals to exchange prisoners even as both sides agree say dia relationship bin don scata. Dem later release joint statement wia dem say Russian-American cooperation go help reduce threat of nuclear war. For di meeting, di two kontris don gree say dem go return ambassadors to dia kontris again. Dis na as Biden bin hala for di conference say dia meeting and agreement no be about trust but mutual interest. Both kontris bin withdraw dia ambassadors early dis year and tins bin fall apart for di relationship, howeva Russia don announce say dia ambassador, Anatoly Antonov go go back America for July. However, neither president don invite di oda to come dia kontri. Recently, America suffer two cyber attacks wey dem bin blame on top Russia head. But for dis summit, Biden tok say dem don agree to set up working group wey go set up agreements on top how dem dey work for di cyber space. Biden also tok say America don identify 16 cyber infrastructures dem wey dem say na part of dia touch not infrastructure and say Russia agree in principle. President Putin bin tok for im own press conference say Biden dey different from Donald Trump on top say e be ""seasoned elder statesman"". Dis na one of di few praise wey di Russian Head of state give Biden for di meeting. Accuse bin of don dey plenti say Russia bin interfere inside America 2016 general elections, to which both Putin and Trump don deny. Putin dismiss America worry ova Alexei Nalvany wey recently do 24 day hunger strike. E say Nalvany bin ignore di law sabi say e go go prison wen im enta back Russia afta dem bin treat am for Germany. Nalvany don accuse oga Putin say na im order make dem poison am with nerve agent but Putin don deny am. Putin say im no want make kasala like di US Capitol riots or di Black Lives Matter protest enta im kontri. But Mr Biden shun Putin comments about Black Lives Matter say e dey 'ridiculous' as im hala say numan rights go ""always dey on top di table""." https://www.bbc.com/pidgin/world-57491521 +entertainment RMD: Richard Mofe-Damijo profile inside six fun facts "Richard Mofe-Damijo, Nollywood veteran actor wey many sabi as RMD, get some unknown facts about him. 60 years ago today July 6, 1961] na im dem born Richard Eyimofe Evans Mofe-Damijo as Urhobo man for Delta state, southern Nigeria. Kack make BBC Pidgin share five correct things you fit no know about RMD. Richard Mofe-Damijo many fans no sabi say na beans be im favorite food. RMD bin love beans and dodo (fried plantain) but e change di diet plan for health reasons. Afta RMD attend midwestern college in Delta state, di Nigerian actor study law for University of Lagos in 1997 and later graduate for 2004. Before e join di entertainment industry, Richard Mofe-Damijo bin work as a journalist. RMD bin work for di old Concord Newspaper and Metro Magazine as a reporter. E go surprise you to know say di actor don dey teach as a Sunday school teacher for at least 10 years and countring now. For one interview e say: ""I be teacher. Dat na wetin I dey do. I don teach Sunday school for over 13 or 15 years. ""And I still dey teach whenever I get di chance to. I just love to pass on di knowledge wey I get."" ''E shock you!"" Well, RMD na grandfather to two grandchildren. Mofe-Damijo dey reularly post for im timeline di cute photos of im grandkids. In 2007 RMD collect appointment as Special Adviser on Culture and Tourism to former Delta State Governor, Dr. Emmanuel Uduaghan. And later as Culture and Tourism Commissioner. RMD now dey for im second marriage, di name of Richard Mofe Damijo first wife be May Ellen-Ezekiel. Before she die, she be publisher and journalist, but she die in 1996. Together with Richard, dem get a son Oghenekome. Richard Mofe-Damijo bin dey part of actors and actresses banned by Nollywood film marketers AKA G8 ban. Di ban dat time na because di affected actors demand huge sums but dem no deliver as dem go expect. Na dis ban lead to di entrance of many new stars into Nollywood. RMD now na married man wey get about five children; Three boys and two girls. RMD current wife na former tv personality Jumobi Adegbesan. Dem marry for 2000, years after im first wife, Ellen-Ezekiel Mofe-Damijo (MEE) die. MEE die in 1996." https://www.bbc.com/pidgin/world-57730446 +sports Cape Verde vs Cameroon live update: Indomitable Lions and Stallions qualify from Group A Cameroon and Burkina Faso don progress to di next round of di 2021 Africa Cup of Nations afta dem draw wit Cape Verde and Ethiopia respectively. Di Indomitable Lions top di group wit seven points but dem find am hard to break down Cape Verde as di match end 1-1. Captain Vincent Aboubakar score im fifth goal of di tournament for di first half as im drill shot into di net. Im goal ensure say di Al Nassr striker score for all three group games for di ongoing tournament. Substitute Garry Rodrigues draw Cape Verde level for di 53rd minute afta im backheel cutback from Rocha Santos. For di oda game for di group, Ethiopia score second half penalty to deny Burkin Faso win dia second match of di 2021 Afcon. Di Stallions bin don take di lead for di 24th minute as Bayala chip di onrushing Ethiopia goalkeeper, Teklemariam Shanko. But Ethiopia cut short dia celebrations as referee Ahmad Heeralall award di Walia Ibex penalty afta video assistant referee decide say Burkina Faso player handle di ball inside di box. Getaneh Kebede convert di penalty to equalise for Ethiopia wey finish di group wit one point afta three matches. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60027208 +sports Czech Republic vs England: Wetin teams need to qualify Euro 2020 round of 16 Ben Chilwell and Mason Mount fit no play for England Tuesday game wit Czech Republic. Di players they self-isolate as precaution afta dey come in close contact wit Scotland Billy Gilmour wey test positive for Covid-19. Gilmour go miss Scotland final group game against Croatia on Tuesday. Tori be say England dey guaranteed a place for di last 16 of Euro 2020 after Monday results, but dem need to win Czech Republic finish as Group D leaders. Sixteen teams go qualify for Euro 2020 knockout stages. Di top two for each group go progress, tori be say dem go play di final group games for June 23. And then four of di six third-place teams go also qualify from di group stage. Group A Italy (9 points, dem do qualify), Wales (dem do qualify 4,), Switzerland (4, dem do qualify through), Turkey (0) Switzerland qualify as one of di four best third-placed teams. Group B Belgium (9, dem do qualify), Denmark (3, dem do qualify through), Finland (3), Russia (3) Finland finish third and now dem must wait to see if dem go qualify. Group C Netherlands (9, dem do qualify), Austria (6, dem do qualify), Ukraine (3), North Macedonia (0) Ukraine finish third and now dem must wait to see if dem go qualify. Group D Croatia (1) vs Scotland (1), Czech Republic (4,dem don qualify) vs England (4,dem don qualify) Czech Republic don qualify and go win di group if dem avoid defeat against England. Dem go finish second if dem lose and Scotland beat Croatia. Dem go only finish third if they lose and Croatia win by scoring more to overtake them on overall goal difference. Group E Wednesday: Slovakia (3) vs Spain (2), Sweden (4) vs Poland (1) Sweden don qualify and dem go top di group if dem beat Poland. If Sweden lose and di oda game end for draw, then go split Sweden, Slovakia and Poland for first to third place on results between di three teams. If Sweden lose dem go finish third. Slovakia need a point to dey sure of qualifying top of di group if dem win and Sweden no win. Spain go qualify if dem beat Slovakia. Dem go also go through if dem draw and Poland fail to beat Sweden. Poland go qualify if dem win. If Slovakia, Sweden and Poland all finish on 4 points (ahead of Spain on 3), then dem go use dia goal difference from matches between di three teams to split dem. In that case, if Poland beat Sweden 1-0, and Slovakia draw, di order go be: 1 Slovakia, 2 Poland, 3 Sweden. If Poland beat Sweden 2-1, and Slovakia draw, di order go be: 1 Poland, 2 Sweden, 3 Slovakia (Sweden and Slovakia go dey behind Poland on goal difference and to split di two their direct result, Sweden win, go apply). If Poland beat Sweden by any oda dan one-goal margin, and Slovakia draw, di order go be : 1 Poland, 2 Sweden, 3 Slovakia. If Poland beat Sweden by two goals or more, and Slovakia draw, di order go be: 1 Poland, 2 Slovakia, 3 Sweden. Group F Wednesday: Portugal (3) vs France (4), Germany (3) vs Hungary (1) Top Scorer: All Ronaldo's goals so far France don already qualify through dem go finish first if they win, or if they draw and Germany fail to beat Hungary. If France lose and Hungary win, den second position go dey decided on overall goal difference. Germany go, go through if dem avoid defeat. Dem go finish first if they win and France no win. Germany go finish third if dem play draw and France lose, or if both Germany and Portugal lose. Portugal go qualify if dem avoid defeat. Dem go finish first if they win and Germany fail to win. Portugal go finish fourth if dem lose and Germany also lose. Hungary will go qualify if they win. If they win and France lose, na goal difference go decide second place. Hungary go finish if they win and oda games end for draw. Di four best third placed teams go qualify https://www.bbc.com/pidgin/tori-57564409 +politics Electoral act amendment bill: Highlights of Electoral Act President Buhari sign into Law "Nigeria President Muhammadu Buhari don sign di Electoral Act Amendment Bill 2021 into law. Buhari sign di Electoral Act on Friday for di Council chambers of di presidential villa for Abuja. Dis new law go affect di way political parties go prepare for di 2023 general elections. Di new Act provide a legal framework wey empower di Independent National Electoral Commission [INEC] to deploy technological solutions for elections in Nigeria. Buhari for im speech describe di bill as reformative and progressive. Di Nigerian leader say e go epp make di Nigerian electoral process dey transparent and kampe. E say di National Assembly gatz still rework section 84(12) of di act. Dis na sake of say e dey prevent political office to vote and be voted for during dia party primaries. And di Nigerian leader maintain say dat one dey against di constitution. Before di passage of di Electoral Amendment Bill to law, both di lawmakers and presidency bin face kata-kata on top some aspect of di bill. Sake of di katakata wey dey always follow election for Nigeria, di Senate for 2019 begin fresh moves to address dis challenges as dem try chook eye for di Electoral Act again. Di katakata include: like cases of violence, ballot box snatching, bloodshed and oda electoral misbehaviour. For 2019, one bill for an Act to ensure say di Independent National Electoral Commission (INEC) adopt electronic voting method for future elections dey introduced and di Bill scale through second reading without any wahala. With di amendment, e dey expected say INEC go operate an electronic database into which all results for election go dey transmitted. Di Bill dey titled, ""A Bill for an Act to Amend di Electoral Act No.6 2010 and for Other Related Matters, 2019(SB.122). E dey sponsored by Deputy President of di Senate, Ovie Omo-Agege, and Co-sponsored by Senator Abubakar Kyari. Dis new law dey reason di amendment of Section 65 of di Electoral Act 2010 by introducing a ""National Electronic Register of Election Results. Wetin e mean be say, di new amendment demands say data of accredited voters must dey transmitted to di central data base. Dis gatz happun afta di conclusion of di accreditation of voters wey vote through di use of di card reader. Di act also reason say, ""at di end of accreditation of voters, di presiding officer go transmit di voter accreditation data by secure mobile electronic communication. Di polling official suppose send am go di central database of di commission wey dem hide for di national headquarters of di commission."" As di lawmakers gada on Thursday to reason di Electoral Act Amendment Bill again, division bin start wen di Committee on INEC on Electoral Act Amendment Bill 2021 present dia recommendations. Di Bill bin cause division among di lawmakers for both di lower and upper chamber. Na over wen dem debate over di mode of transmission of results by di Independent National Electoral Commission on election day. Some lawmakers bin argue say na di work of INEC. Odas debate say di power to determine how dem go take transmit election result electronically suppose dey di hand of di Nigeria Communications Commission wit di approval of di National Assembly." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60496150 +health Abuja community wia pikin dem dey die sake of no beta hospital To give birth to pikin suppose be time for celebration, but for most poor women for Chibiri community for Kuje local goment area of Abuja Nigeria, na time for weeping and sorrow. 21 year old Janet bin dey prepare to welcome her first child, but wen labour come, she no get moni to go hospital. Some old women for her compound try to epp her deliver but in di process, her pikin die and since den she neva heal from her pain. Janet and many indigenous Abuja women no get access to medical health and medical personnel wen dem dey give birth. Many of dem tell BBC pidgin say dem no get moni to go hospital for town. President Muhammadu Buhari bin promise for 2015 to repair more than 10 thousand primary health care centre to solve dis wahala but na only 109 goment don renovate yet. According to di United Nations Children's Fund, one out of every 34 pikin wey dem born for Nigeria, dey die before dia first birthday. Producer: Dooshima Abu Video journalist: Fatima Othman https://www.bbc.com/pidgin/49431279 +politics Oshiomole collect warning from court to stop to dey parade as APC national chairman One Federal Capital Territory High Court don grant an order to stop Adams Oshiomhole from parading imself as di National Chairman of di ruling All Progressives Congress (APC for Nigeria. Justice Danlami Senchi wey grant di order on Wednesday say di political parties must be bound by dia constitution and as im ward bin don suspend am, Oshiomhole no suppose dey function as di National Chairman of di party pending wen dem go hear di mata. Di judge fix di case for April 7 and 8, 2020. Pipo bin don dey ginger make dem comot Oshiomhole, say im don fail in im duties of providing ogbonge leadership for di party, sometin wey di APC leader dismiss say di group no get mouth. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51739326 +business Electricity workers for Nigeria suspend strike Nigerian electricity workers don suspend dia nationwide strike, wey don cause total blackout for different parts of di kontri. Di electricity workers under di joinbdodi of di National Union of Electricity Employees (NUEE) and Senior Staff Association of Electricity and Allied Companies (SSAEC) gree to suspend di strike, following di intervention of di Minister of Labour and Employment, Sen. Chris Ngige. Ngige bin summon one emergency toktok meeting between di Federal Goment and di electricity workers on Wednesday to resolve di issues wey cause di strike. Di workers bin alleged contravention of dia Conditions of Service and Career Progression, stigmatisation of electricity staff by di Office of the Head of Service of di Federation and refusal of di market operators to fund di payment of entitlements of ex-PHCN staff as dem agreed for di 2019 agreement. Wen e dey follow tori pipo afta di meeting wey happun for Abuja on Wednesday, di President of NUEE, Comrade Joe Ajero, say dem don ask dem to stop di strike action. Ajaero dey hope say di federal goment no go do dem one kain ontop di mata wey don dey for ground tey tey. E say dem go pause di strike and wait for two weeks as dem gree for di meeting for di goment to address dia grievances. Wen e also follow tori pipo yarn, Ngige say afta dem don do toktok wella ontop di mata for hand dem gree to constitute one bipartite committee to chook eyes into di grievances of di electricity workers and report back in two weeks. According to Ngige, di members of di committee include di Minister of State for Power, Jeddy Agba(Chairman), Permanent Secretary, Office of the Secretary to goment of di Federation, Permanent Secretary, General Services, Office of di Head of Service of di Federation, Permanent Secretary, Federal Ministry of Labour and Employment, representative of BPE and two representatives from NUEE and SSAEC. Di committee get two weeks to report back to di whole house. Di union bin threaten to begin strike from 17th August 2022 so dat goment go listen to dia demands. Wetin di Transmission Company of Nigeria workers dey ask for na : Dem say dem no go call of di strike until goment answer dem. Di Federal Goment say dem dey hold discussions wit di organized labour in order to proffer resolution to various issues wey don make electricity workers in di konytri to begin strike. Di Minister of Power, Abubakar Aliyu reveal dis to di State House correspondents after di Federal Executive Council meeting wey President Buhrai chair on Wednesday. E tok say di issues in contention center around employment wey dey largely under di purview of di Head of Service and not di Ministry of Power. Official of TCN bin tell BBC Pidgin earlier say “if goment to solve dis issue now e go affect di economy of di kontri and pipo go begin soend money buy fuel wey goment increase price from 165 naira to over 170 naira per litre to power dia business and dis go increase cost of goods and services. Di goment begin di privatisation of the power sector in 2000s. For 2013, dem privatized 11 electricity distribution companies (DISCOs) and six generating companies (GENCOs) while retaining 100% ownership of di Transmission Company of Nigeria. But corruption and inefficiency don pafuka im progress. Nigeria’s power generation dey mostly thermal and hydro wit installed capacity of about 12,522 Megawatts. But, di constant collapse of di national grid since di start of di year don make am to only able to distribute about 4,000MW; wey dey result to epileptic supplies of electricity to cater for over 200 million pipo. Incessant power cuts don force plenti Nigerians, wey include entrepreneurs to rely mostly on petrol or diesel powered generating plants to power dia homes and businesses. Di distribution companies for some states issue statement to inform dia customers about how di strike go affect dem. https://www.bbc.com/pidgin/articles/clmke152m0do +business Cameroon latest news: Tomato farmers tok how border wey goment lock di cause dem ‘heartaches’ and debts "Mbombo Yaye, laik plenti farmers for Cameroon di hear bad as deh no fit sell tomato out-side kontri laik before, price don drop, and market no dey. ""Just now ah di fear heart attack as ah no fit pay about FCFA six million weh ah borrow for work tomato"", Mbombo Yaye tell BBC New Pidgin. Cameroon lock borders for March 17, 2020, for stop de spread for coronavirus and tomato farmers na some group of pipo weh deh lose plenti. Just now, for seka say borders bi locked, we no fit sell we tomato, motor dem di waka inside quarters for sell but we di lose plenti, big market na outside kontri, Yaye tok. ""Ah farm tomatoes for six hectares for Mbalamba for Mbam et Kim, center region. For plant sotei harvest, ah di spend laik 1.5milion for hectare. Pay pipo for work de farm, plant, weed, harvest and transport tomato for market"", Yaye explain. Price for tomato now na FCFA 1500, FCFA2000, FCFA 2500 and FCFA3000 and e depend for de basket. ""For harvest one basket tomato, ah di pay for FCFA 100; for arrange and tie FCFA 200, FCFA 100 for carry am for roadside and pay motor from farm to FCFA 150,000 for carry 250 baskets to Marche 8em"". Wen ah calculate weti ah spend na only FCFA 600 di komot for basket, we no fit even get half of de moni weh we invest for work de tomato, Yaye tok. Before, Nigerians bi di kam buy tomato from Marche 8em for Yaoundé, den, basket bin bi na FCFA 6000 - 8000. Farmers bi di take dia tomato from Foumbot for west region go sell for Gabon. Dis taim last year, we bi di sell tomato for Nigerians weh deh di kam buy for FCFA 8000. Before midday, tomato don finish for market, Yaye tok. According to Yaye, de situation don cause die for two farmers for Bangante, West region. Also, one shop owner weh e bi di borrow farmers up to 55million, wen e hear say deh di sell for basket for 2000, e hang e sef, Yaye tori. Just now, for ma house chop moni na FCFA 2000, and ah di tell ma woman say na tomatoes dey make deh cook am wit anytin. Before ah use to give FCFA 3500 as chop moni. E di hard now for pay house. Before ah bi use to pay two moons one taim, but now ah fit give landlord weti ah get. Ah thank God yi too di understand say outside bad. Goment don promise for give dem some machines, fertilisers, pumps, and other farm inputs for farmer and di still check how for re-open border. Yaye say na good tin for support dem. But, weti deh want na make goment reopen land border make deh sell dia tomato to oda kontris. Also, make goment open company for process tomato or reopen, SCAM for Foumbot, centre for tomato for kontri for 1998. For dat taim, deh company weh e bi di process tomato bi di weigh for killo buy and problem no bi dey. For now, e no bi clear how many tons for tomato Cameroon di produce, na as borders lock weh kontri pipo di see say Cameroon di farm plenti tomato." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53464879 +sports Karim Adeyemi: Biography of RB Salzburg player wey dey linked to Liverpool RB Salzburg player Karim Adeyemi, name full pipo mouth afta im Champions League performance on Wednesday. Adeyemi bin score two goals to help im team beat LOSC 2-1 for dia second group G match. Many pipo don dey link am wit move to English club, Liverpool. Dis na eviritin you need to know about di striker. Karim Adeyemi na 19 year old German born striker wey dey currently play for RB Salzburg for Austrian Bundesliga. Adeyemi bin start im professional career for SpVgg Unterhaching wia im rise from di youth system to eventually play for di U19 Bundesliga side. Afta im shine well-well, Austrian side RB Salzburg decide to sign am for a three-year deal. As soon as Adeyemi bin sign for Salzburg, im go on loan to dia 'feeder' club FC Liefering. Adeyemi bin shine well-well during im time for Liefering and sharpaly RB Salzburg call am back to di team. Afta dem lose di likes of Erling Haaland and Takumi Minamino, Salzburg begin dey rely on Adeyemi a lot to help dia attack. Im first full season for di Austrian Bundesliga for 2020/21 bin dey very impressive and na dia wey world scouts really start to notice am. Adeyemi bin play 29 games for di Bundesliga for Salzburg and score seven goals and seven assists wey help Salzburg to win dia League title. For dis 2021/22 season tins dey even better for am, e don score six goals for di opening six games for Salzburg Already sef German national team coach Hansi Flick don invite am to di national team. Adeyemi bin come on for di 71st minute against Armenia and even score sef for im debut. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58750520 +sports Nigeria vs Netherlands: Golden Eaglets lose 3-1 for round of 16 Nigeria Golden Eaglets don crash out of di 2019 Fifa U-17 World Cup wey dey go on for Brazil. Di Golden Eaglets suffer 3-1 to Netherlands for dia round of 16 match early dis morning. Netherlands striker Sontje Hansen score three goals as Nigeria under 17 no fit stage comeback dis time like dem do for two of dia group stage match. Olakunle Olusegun na im score di only goal for Nigeria wey be five time champions of di tournament. https://www.bbc.com/pidgin/sport-50312710 +sports Rafael Benítez: Everton FC name Spanish football manager dia new coach Everton don appoint Rafael Benitez as dia new manager. Benitez sign a three-year deal on Wednesday June 30, 2021. Di sixty-one year old former Liverpool boss go take over from Carlo Ancelotti. Di Italian resign from him post to return to Real Madrid on June 1. Benitez last manage Premier League side Newcastle before leaving for June 2019. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57675123 +entertainment Adesua Etomi twins: Funke Akindele, Toolz O, odas react to Adesua and Banky W Wellington video testimony dia child birth journey "Reactions don follow Nigerian celebrity couple, Banky W and Adesua Etomi interview about dia journey to parenthood. For di interview wit The Waterbrook Church, di couple reveal di tough times dem pass through, pressure dem face from pipo, dia experience with IVF to conceive twins and how dem later lose di children. Banky Wellington wey share di video for im social media page say, di tori wey dem share for di video fit ""make you laugh or cry. But dis na hope say e go also help you heal and build your faith."". He also tok say, dis na di tori behind im song ""Final say faith"". Di almost one-hour video don generate conversations on social media since di release on Monday, fellow celebrities don react to di revelation. Nigerian actress, Funke Akindele drop comment for Banky W Instagram post, Thank di couple for sharing dia tori wit everyone. ""Thank you for sharing dis with us. Thank you thank you. Thank you. ❤️❤️❤️❤️❤️❤️❤️ @adesuaetomi @bankywellington"" she tok. Popular online personality Toolz O also react to say ""❤️❤️❤️ God dey always comes through"". Anoda media personality Gbemi O, also affirm how many pipo dey go through so much pain in silence . ""So many of us go through so much pain in silence . God bless you ."" she tok Adesua and Banky W tok about dia trying times say na tough period for dia life. ""Dem yab me every single day, for two-and-a-half years before I get pregnant and born my son."" ""I no fit get one opinion without one pesin saying go and born, I no fit tok anything without one pesin saying get out go born, you dey barren, you do something with your womb."" Adesua tok. Adesua also tok say as her mama be pastor, she don see as pipo wey dey wait on di lord for di fruit of di womb come meet her mama and she dey see dia pain and na ""We get pregnant, and we get pregnant with twins. We do scan, we see di heartbeat, na only few pipo sabi wen dis wan happun. Everything bin dey fine but during one routine check-up to go do scan and I just see di doctor face... and she say Adesua I dey find di heartbeat."" Adesua say, she and Banky W dem decide to pray and wait for days before dem go back di hospital, but di babies no make am. Something she bin don ask God make e no make her go through dat journey." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56646817 +entertainment Valentine's Day: How Nigerian female celebrities slay for fans on Valentine day Married couples, Lovers, Friends and families all ova di world dey celebrate, exchange gifts and show love to each today February 14 wey be Valentine day. Red na di common colour wey pipo all ova di world dey use celebrate dis day and Nigerian female celebs no dey left out for di celebration. Na so so slay mama as dem no come to play and na so dem post beautiful pictures of demsef for social media to wish dia fans Happy Valentine's Day. Here be some photos of how Nigerian female celebs take slay with dia red dress and top-notch make up. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56062104 +business CBN don revise cash withdrawal limit, dis na di new update Di Central Bank of Nigeria don announce decision to revise di cash withdrawal limit dem first set. For one circular wey dem address to all Deposit Money Banks and oda financial institutions for di kontri on Wednesday 21, December, 2023, CBN tok say dis revised cash withdrawal limit na based on di feedback wey dem receive from stakeholders. Dis dey come following several toktok by Nigerians wey bin dey para say di limit dey too low. Di Nigeria House of Representatives don also Apex bank govnor imsef, Godwin Emefiele to come ansa questions about di intial cash withdrawal limit. Di directives go take effect from January 9, 2023. Di apex bank say di new policy na in line wit di launch of di redesigned N200, N500 and N1,000 notes wey President Muhammadu Buhari do on November 23, 2022. Dem believe say di redesigned notes go reduce di amount of cash wey dey in circulation and therefore restricts di way kidnappers take dey demand ransom plus e no go also make politicians fit rig elections. Di following directives still stand: Wetin customers go need provide to fit collect cash wey pass di limit na: CBN further tok for di letter sayi. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw47ywlvx3zo +sports Kamaru Usman: 'Di Nigerian nightmare' lose im welterweight title to Leon Edwards for UFC 278 "Leon Edwards don knock out Kamaru Usman to win di welterweight title at UFC 278 for Salt Lake City, Utah. Behind on points for di fifth, Edwards, 30, land one ogbonge left high-kick to stun Nigeria's pound-for-pound number one fighter. Kamaru defeat dey come hours after Usyk win Anthony Joshua on split decision to retain heavyweight titles, See how di fight waka. Edwards becomes di first British champion since Michael Bisping for 2016 and only di second in history. ""You all doubt me, say I no fit do am. Look at me now,"" Edwards tok after di fight. ""I come from di trenches. Na like dis dem build me. Daem don doubt me my whole life but look at me now."" In beating Usman, Birmingham's Edwards avenge im defeat in 2015 and end di 35-year-old's 15-fight unbeaten streak for di UFC. Jamaican-born Edwards, wey be big underdog wit bookmakers going into di bout, extend im winning streak to 10 following di defeat to Usman seven years ago. Usman win di first fight by using im wrestling to control di majority of di contest - one tactic wey Edwards say open im eyes to weaknesses for im own grappling game. Following dat bout Edwards work hard on im wrestling and di improvements wey e make show from di start of di rematch. For di first round e trip Usman, becoming di first fighter for UFC history to complete a takedown on di Nigerian. Usman respond strongly for di second and third round, pressuring Edwards wit flurries of strikes and controlling much of di contest with im grappling. At di end of di round Edwards' corner loudly urge dia fighter to up im game and ""get im hands moving"". Edwards start to dey show signs of fatigue for di fourth, with di relentless grappling from Usman, as di champion land one ogbonge takedown and continue to control di fight. With Usman likely ahead on points going into di fifth Edwards need something wey dey special - and e get am. Witt one feint e lure Usman's head to di side, before landing one clean left high-kick, leaving di Nigerian nightmare stunned on di canvas. Edwards jump on di cage for celebration as e realise di enormity of wetin e don achieve. UFC commentator Joe Rogan say di kick wey end di fight fit be di dey best wey e don for di UFC, with Edwards shocking Usman for di fifth while behind on points being arguably di sport's biggest ever upset." https://www.bbc.com/pidgin/62622464 +entertainment Who be Aaron Carter, di singer and rapper wey die "Former Disney Star, Hilary Duff na one of di many celebs wey don comot to mourn di death rapper and singer Aaron Carter. Di actress wey be teenager wen she and Aaron date publicly say, her teenage self love am deeply. Oda celebrities wey mourn im loss include New Kids on the Block, Diane Warren, Spencer Pratt and Melissa Joan Hart. Aaron Carter die on Saturday at di age of 34. E die one month to im 35th birthday and two weeks before im son Prince go turn one year old. LA Police say dem go im house to find am unresponsive but neva give out cause of death. Aaron Carter na di younger brother of Backstreet Boys star Nick Carter. Carter start im career at di age of nine years old. E bin start by doing opening acts for di boy band Backstreet Boys for dia tours and concerts before im go do im successful career. For di late 90s and di early 2000s, e sell millions of copies of im four albums. Im second album, Aaron's Party (Come Get It) bin comot fir 2000 and go triple platinum. Afta d album, e chook hand with Backstreet Boys and Britney Spears for di Oops!... I Did It Again tour. As e dey grow, Carter start to dey rap, do Broadway musicals and appear for di TV show, Dancing With th Stars. E also face plenti wahala, as im enta rehab plenti times and file for bankruptcy fo 2015 sake of millions of dollars tax gbese. Police and am jam wella, ontop drug possession and reckless driving. But earlier dis year im do interview with Daily Mail tell dem say, e no want make dem dey look am as ""train wreck"" again. For 2021, dem born Carter pikin Prince and tori from di Holly Reporter be sat e bin go rehab dis year to gain custody of am. Afta im death, Prince mama Melanie Martin bring out statement say she bin ""dey di process of accepting dis unfortunate reality.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/ce4rep8e9p1o +health Coronavirus: Ghana observe national fasting and prayer today as covid-19 cases reach 53 "Ghanaians dey observe national day of fasting and prayer for protection against Coronavirus today. Both Muslims and Christians dey join de fast wey Prez Akufo-Addo declare sake of de coronavirus pandemic. During en televised broadcast, Prez Akufo-Addo talk say ""I dey appeal to all Ghanaians, Christians den Muslims, say dem for observe national day of fasting and prayer."" ""Make we pray to God so say he go protect wana country den save us from dis pandemic"" he add. Ghana Union of Traders Association (GUTA) also urge dema members say dem for lock up dema shops den join de national fast and prayer. Anthony Oppong, Ashanti Regional Chairman of GUTA talk say ""we decide to add wanna voice to encourage wanna members say make dem join. Also, make dem lock dema shops so say dem fit make time to pray to God."" Ghana close all air, land and sea borders sake of increasing Coronavirus infections wey people import into de country. Tourism authorities don also close beaches till further notice as precautionary measures to contain di spread of di disease. However, Ghanaian citizens den foreign nationals who get residence permits go enter mandatory quarantine if dem arrive Ghana before Sunday midnight. Dis move be part of ways wey go ""limit den stop de importation of de virus, contain de spread, care for de sick well-well, reduce de impact of de virus on social den economic life den inspire de increase Ghana en domestic power den self-reliance"" President Akufo-Addo talk. He make dis announcement after Ghana record first covid-19 death case where one Lebanese who chop 61 years die for Kumasi. Officials say de patient wey die get some other health conditions in addition to coronavirus. Di authorities encourage di pipo make dem obey social distancing rules. So far, de country record 53 infections, 2 deaths den no recoveries." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51993919 +sports Ogbonge American sports journalist Grant Wahl sudden death for Qatar cause shock "One ogbonge football journalist from United States don die as e dey cover di World Cup for Qatar. Grant Wahl, 48, bin suddenly collapse as e dey watch di Argentina-Netherlands game on Friday night. Early reports dey suggest say im bin get heart attack, but dem neva still confam dis officially. Last month, Qatar authorities bin briefly detain Wahl for trying to enta one stadium wearing rainbow shirt, in support of LGBT rights. According to Qatar World Cup organisers, di Supreme Court Committee for Delivery and Legacy, Wahl bin “fall sick” for di press area and im bin receive “immediate medical treatment for di site.” ""Im fall sick for di Lusail Stadium media tribune, during last night quarter-final match between Argentina v Netherlands. Im receive immediate emergency medical treatment on site, wey continue as dem transfer am wit ambulance to Hamad General Hospital. ""We dey in touch wit di US Embassy and relevant local authorities to make sure di process of sending di body back home na according to im family wishes."" Wahl death cause shock and pain to di sports world. For one statement, di US Soccer Federation say im dey ""heartbroken"" by di news. ""Fans of soccer and journalism of di highest quality sabi say we bin fit always depend on Grant to deliver insightful and entertaining stories about our game, and im major characters,"" e tok. For one tweet, oga Wahl wife, Céline Gounder, say she dey in ""complete shock"", come add say she dey ""so thankful"" for di support wey she don receive from friends. FIFA President Gianni Infantino say Wahl love for football bin dey ""strong"", come add say “everybody wey dey follow di international game go miss” im reporting. Tok tok pesin for di Supreme Committee for Delivery & Legacy, say: ""We dey deeply sad by di death of di US journalist Grant Wahl. ""Grant dey known for im serious love of football and bin dey Qatar to cover im eighth Fifa World Cup. Grant Wahl bin report eight World Cups back to back, wit im first for di US for 1994." https://www.bbc.com/pidgin/articles/ceq2e646xxzo +entertainment BBNaija 2020 Eviction: Kaisha don comot from Big Brother Naija season 5 - See how fans vote dia favourite housemate Kaisha na di latest housemate to comot from di Big Brother Naija show afta four weeks for di house. She dey part of di four housemates wit di lowest votes from fans of di reality show dis week. Her eviction dey come one week afta Eric and Tochi become di second set of housemates wey big brother ask to leave di house afta dem pull di lowest votes from fans and housemates. Ka3na and Lilo na di first set of housemate to comot. Di votes of di fans of di big brother Naija show na im dey determine di last four housemates wey go dey up for eviction every week. Na Kaisha dey lead di bottom four votes with 3.48%, Trikytee follow wit 3.47%, Wathoni get 3.25% and Neo dey down di ladder wit 3.13%. First week of eviction Second week of eviction Kaisha get 2.41% votes, Trikytee get 2.29% votes, Tochi na 2.11% votes, while Eric, wey dem bin nominate for eviction from di previous week, get di least votes wit 1.91%. Out of 20 housemates wey start di race to win di 85million naira price, na 14 of dem remain to battle for votes from di public and housemates to get chance to be di last pesin standing. At least one out of di 16 housemates wey dey up for possible eviction go leave di show on Sunday and di house get power to decide who dat pesin go be. Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room. Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house. Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53799622 +entertainment Eddie Van Halen: Quick facts about rock guitarist wey die from cancer at di age of 65 Eddie Van Halen, di ogbonge guitar man and co-founder of di popular rock band Van Halen don die from cancer at age 65. Di Dutch-American musician bin dey receive treatment for throat cancer. Top rock musicians don already dey pay dia last respect to am. Van Halen na one of di biggest names for rock music industry. Im be di pikin of Eugenia and Jan Van Halen wey dem born for Amsterdam, Netherlands. Im interest for music bin start from small wen im learn how to play piano. As Van Halen grow up, im switch to drums den guitar wey im bin dey play wit im popsi and brother for weddings. Tho pipo sabi im band, Van Halen for dia song 'Jump' wey hit top of di US charts for 1984, e get some tins wey many pipo no too sabi about am. Guinness World Record bin recognize Van Halen afta im perform wit im band for one US Festival for California wia dem make $1.5 million for 90 minutes. Di record book say di performance na di highest paid single appearance from one band, as at dat time. Van Halen carry creativity enta anoda level wen im sample di sound from power drill for one im tracks, 'Poundcake'. You fit hear am for di song intro and di guitar solo. Tori bin spread say Van Halen band no dey allow brown M&Ms for dia backstage and many pipo tink say na just rumour. But true-true, di band include am for dia list of request during any show performance to make sure say di venue read di document well-well. For 2007, Van Halen bin enta di Rock and Roll Hall of Fame and for 2020, Guitar World put am as number four for dia annual poll of '100 Greatest Guitarist of All Time'. https://www.bbc.com/pidgin/world-54445757 +health UK lockdown update: England and Scotland new rules, 'stay at home order' as coronavirus cases rise "Pipo for all of England and most of Scotland must now stay at home except for some small set of pipo wey get permission with reasons, as new lockdowns begin inside both nations. Schools don dey closed to most pupils inside England, Scotland and Wales, while Northern Ireland go get an ""extended period of remote learning"". England rules dey expected to last until mid-February, while Scotland go review dia own by di end of January. PM Boris Johnson warn say di coming weeks go be ""di hardest yet"". Dis wan dey come afta UK report a record of 58,784 cases on Monday, as well as a further 407 deaths within 28 days of a positive test. As e announce England lockdown, Mr Johnson say hospitals dey under ""more pressure from Covid dan at any time since di start of di pandemic"". E order pipo to stay indoors with only small exceptions - like essential medical needs, food shopping, exercise and work wey dem no fit do for home - and say make schools and colleges immediately move to remote teaching for di majority of students. And e say all care home residents and dia carers, everyone wey be 70 and over, all frontline health and social care workers, and those wey dey clinically extremely vulnerable go get one dose of vaccine by mid-February. Although di rules become law in di early hours of Wednesday, di PM say make pipo begin follow am now. Earlier on Monday, First Minister Nicola Sturgeon issue stay at home order for Scotland, beginning at midnight and lasting until di end of January. Scotland lockdown, wey na for di mainland and Skye, go also see schools dey closed to pupils, places of worship closed and group exercise banned. ""No be exaggeration to say I dey more concerned about di situation we face now dan I don dey at any time since March last year,"" Ms Sturgeon tok. Wales, wey dey national lockdown since 20 December, say schools and colleges go dey shut until January 18 for most pupils. Meanwhile, Northern Ireland, wey enter six-week lockdown on Boxing Day, plan to put dia own stay-at-home message into law, and go get an""extended period of remote learning"", di Stormont Executive tok. See di New rules For England: Inside mainland Scotland and Skye:" https://www.bbc.com/pidgin/world-55530002 +politics Babtunde Fashola: 'I no get hand for 2023 presidential campaign poster' "Nigeria Minister of Works and Housing, Babatubde Fashola say im no get hand for one presidential campaign poster wey bin go viral for social media for weekend. Di poster bin show di Minister and Govnor of Borno state, Prof. Babagana Zulum pose as presidential and vice presidential candidates wey one support group, ""Di Nigeria Project 2023"" dey behind. However oga Fashola media aide, Hakeem Bello for inside statement say make Nigerians ignore di poster as di group no contact di minister or ask for im consent before dem issue invitation. Di Nigeria Project 2023 wey dey signed by one Abayomi Mademaku as di convener, say di group go launch di campaign on October 2nd. ""Ordinarily, di poster and di various social media reports na something wey go dey normally ignored as di handwork of mischief makers. However, e become necessary to issue dis disclaimer for two key reasons. Di first na to answer with a strong negative to di numerous inquiries from well-meaning Nigerians on weda di group don contact di Honorable Minister or if di groups bin get im permission before dem issue di invitation. No individual or Group don contact di Honorable Minister for or on behalf of The Nigeria Project 2023. As Honorable Minister, Mr Fashola dey currently focused on leading im dedicated Team in di Ministry of Works and Housing to deliver on di mandate of President Muhammadu Buhari for an expanded and upgraded road transport infrastructure; and affordable Housing nationwide in order to achieve economic growth and prosperity for di citizenry. "" Na so di statement tok. No be only oga Fashola wey be former Lagos state govnor don come out to say im neva show any interest to run for 2023 general elections. Earlier, tori say Nigeria Vice President, Professor Yemi Osinbajo go run for President for 2023 bin also fly up and down as pipo don already dey drum campaign for am but e comot to deny di tori. Also di presidential candidate for di Peoples Democratic Party during di 2015 general election, Atiku Abubakar and di Ekiti state governor, Kayode Fayemi bin say dem no get hand for online posters wey bin declare support for dem as president for 2023. Meanwhile, Southern govnors for inside communiqué afta one recent meeting dem get bin agree say di next president of Nigeria must comot from di southern region." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58700379 +health Coronavirus: Ghana students build low-cost ventilators to fight Covid-19 Countries all over the world dey battle plus the infection and spread of Coronavirus. Dis virus which reached pandemic levels is shut down economies, crippling health care systems wey e san kill thousands. But Ghanaian students, volunteers with support from one engineer develop local solutions to fight Covid-19. Professor Fred McBagunlori support students and volunteers build low-cost ventilators from local materials like leather, plastic pipe, wood and vehicle parts. The squad dey hope say with dema ventilator innovation, dem go fit save lives of people wey no fit breath sake of Covid-19. Producer: Favour Nunoo https://www.bbc.com/pidgin/tori-52618837 +politics How dem knock Kemi Badenoch comot race to become UK Prime Minister "Kemi Badenoch don dey knocked out of di race to be di next prime minister of di United Kingdom. Liz Truss don narrow di gap wit Tory leadership rival Penny Mordaunt, as dem battle to secure a place in di run-off vote among members. Former chancellor Rishi Sunak again top di latest MPs' ballot wit 118 votes, suggesting e dey likely to secure a spot in di final two places. Ms Mordaunt come second wit 92, only six votes ahead of Ms Truss wit 86. Kemi Badenoch, who come last wit 59 votes, don dey knocked out of di contest. Di three remaining candidates face a further vote by MPs on Wednesday to decide who go make di final two. Voting go dey thrown open to 160,000 Tory party members to pick di winner, wey go replace Boris Johnson as prime minister on 5 September. Contenders gass get 119 votes from Tory MPs to get into di run-off, suggesting former chancellor Mr Sunak dey likely to secure a place. Foreign secretary Liz Truss close di gap on Trade Minister Penny Mordaunt in Tuesday's vote, gaining 15 more MP votes to Mordaunt's gain of 10. Di pair go now go all out to grab di votes of dose MPs wey back Ms Badenoch, as dem bid to secure a place in di run-off. Former Tory leader Iain Duncan Smith wey dey back Ms Truss say di result show say she ""get di momentum"" and bin gada support from a wide range of Conservative MPs. Tory MP Maria Miller wey be Mordaunt supporter say her candidate go offer a ""fresh choice"" for members and tok say her campaign go now focus on wooing Badenoch supporters. Ms Badenoch wey be former equalities minister na di breakthrough candidate of di contest. She win support and gain attention wit her straight-talking approach and emphasis on cultural issues wey don divide di party in recent years. Her departure from di contest go trigger a scramble among remaining candidates to secure di support of di 59 MPs backing her on Tuesday. Badenoch backer Ben Bradley predict her voters fit go ""in all directions,"" and e neva decide who e go back in Wednesday's vote. One Sky News debate scheduled for Tuesday evening bin dey cancelled, afta Rishi Sunak and Liz Truss say dem no dey take part. Instead, di remaining hopefuls go look to get support from Tory MPs during a hustings wey Onward think tank and the Northern Research Group of Tory MPs representing seats in the north of England bin host. Di placings neva change but a close look at di numbers tell us how unpredictable dis contest be. Thirty one votes bin dey up for grabs from Tom Tugendhat's supporters afta dem eliminate am from di last round. E dey clear dem neva move as a block as all di candidates don gain votes. Liz Truss don keep up her momentum but e no dey enough to leapfrog Penny Mordaunt wey pick up enough votes to stay in second. Rishi Sunak only gain three votes, and e show say while e dey in front from di start e no be runaway lead. Di race dey very tight and at dis point e dey impossible to call." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjm1jj1jzg4o +health Ghana President Nana Akufo-Addo to UN - 'Stop dey use Covid-19 vaccination as immigration control against Africans' "De 76th United Nations General Assembly dey go on for New York, dis week. Global leaders gather in dema numbers to discuss issues which dey affect de world. West African leaders like President Akufo-Addo of Ghana den Muhammadu Buhari of Nigeria dey in attendance. On Wednesday, Prez Akufo-Addo of Ghana address de Assembly on some key issues. Dis be some of de concerns he raise. Ghana Prez Nana Akufo-Addo call on world leaders to stop dey use Covid-19 as immigration control against Africans. Addressing world leaders during de 76th UN General Assembly, he describe de move by some Europeans who fail to recognize vaccinations manufactured in India as ""retrogressive."" ""One unfortunate development be say to enter some countries for Europe with Covidshield, Oxford-AztraZeneca manufactured by Indians no be recognized"" Prez Akufo-Addo explain. Speaking on Ghana, Prez Akufo-Addo mention say de country dey make progress in de fight against Covid-19 pandemic. He mention plans to vaccinate some 20 million Ghanaians by the end of de year as part of efforts to reduce spread of de pandemic. Ghana Prez and ECOWAS leader, Prez Akufo-Addo reveal say Guinea coup makers promise to release President Alpha Conde who dem overthrow and detain. Speaking to de world leaders, he reveal say following en last visit to Guinea as ECOWAS leader, de military junta give am indications of plans to release de deposed leader. Prez Nana Akufo-Addo also talk about how United Nations for support ECOWAS sanctions dem leash out on Guinea after de coup. According to him, make de UN support de moves of ECOWAS which ban Mali and Guinea from regional bloc den help apply pressure on de military junta to hand over power to civilian governance." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58661993 +entertainment Erica and Kidd video: BBNaija 2020 housemates 'entanglement' for di season five lockdown house Fans of BigBrother Naija reality show dey drag Erica and Kiddwaya for social media afta video show two of dem dey 'play love' under dia bedsheet for di house on Sunday. Di incident hapun afta di live eviction show for di reality television show. Although dia actions no too shock fans, onto say, dem tell dia fellow housemates say dem like each oda and on different occasion Erica and Kidd don kiss. Fans don even give di couple name 'kiddricca'. Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London. She say she dey passionate to be big time celebrity and like to get drunk and dance in front of di mirror alone. Praise and Katrina entanglement video shock fans sake of say di two of dem no show any sign of relationship between dem. Dat na why di video of two of dem for di same bed for night dey play with each oda under dia bed sheet shock fans well-well. Lilo and Eric na d first ship wey sail inside di BigBrother Lockdown house. Di two of dem spend most of dia time for di house for each oda company. And e no tay dem share dia first kiss togeda. During Lilo two weeks stay for di house, she share her bed with Eric and di couple play love wella under dia bed sheet. On Sunday Big Brother evict Lilo and Ka3na from di house afta dia fellow housemates nominate dem afta dem get di least votes from di public. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53641154 +business Bank of Ghana introduce new GH¢100, GH¢200 banknotes den GH¢2 coins "Bank of Ghana (BoG) launch new higher Ghana cedi banknotes for de country on Friday. De new banknotes, GH¢100 and GH¢200 banknotes be de latest addition to de currencies wey people go use for Ghana. Also, den say dem go introduce GH¢2 coins for de system. De new denominations go start dey circulate from next week. Governor for Bank of Ghana, Dr Addison talk for press conference say ""dem think deep into de decision to introduce higher cedi denominations."" He san explain say ""we need banknotes den coins which go be convenient give most people sake of e be high quality, secure and cost-effective.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-50567324 +health World mental health day: Anglophone IDP pikin dem di share dia tori for heal "Ashwenbom na 17-year old pikin, one of de young pipo weh deh di suffer pain and worry for seka de gunshots, die-bodi, wounds for seka de crisis for Northwest and Southwest regions for Cameroon. Anglophone crisis don enta number four year, plenti pipo don run go oda areas for fear of gunshots-bullet fit kill dem, and she see how deh di kill pipo. For three years we live in fear as we house bi dey for middle, for one side separatists fighters, (Amba boys) dia camp and for de other side army. Im tell BBC Pidgin. ""We hear plenti guns shots sotei de tin di sound for hear all de taim."" ""If not for God ah for don die, ma mami send me for kontri Sunday and as ah komot for house amba boys and army start shoot"". ""Ah run, confuse, just stand for one place. Wen shooting start, army see you deh go shoot, but ah get luck dat day, 'mbere' (soldier) signal me for run from where ah hide. ""Den as ah di run ah see amba boy e tell me for run enta wan old mami e house. Ah sleep for de old mami e house go back de next day. Mami don di craiy as deh kill some boy for quarter e check say na me"". ""Mami, we no go fit continue wit de too much guns shots, we di jump any taim we hear noise, we mind no di rest, we must leave"", Ashwenbom tell e mami. Ashwenbom weh e drop for school and suppose for enta university dis year kam Yaoundé wit e mani. ""Dis experience don make me ah no wan see or hear gunshot because e di cut ma heart, and some taims ah di just feel sad, but ah thank God say we komot for Kumba kam Yaounde."" Im tok. Franca Sulem Yong na woman weh e use tori for heal Anglophone pikin dem, as e believe say dia tori dem form de Anglophone crisis bi unique and deh need for tell'am. Sulem Yong, wey be di coordinator for Positive Youths Africa, wit e partner HARo organise story telling for helep young pipo, 13-19 years for free dia minds, tink positive as activity for mark mental health day. ""We tell dem say dia stories bi unique and deh get for tokam as e di helep dem release dia pain, make dem strong"", Sulem Yong tok. As na young pipo weh deh still get big imagination, and di form who deh wan bi, we also teach dem exercises for keep dia mind present and happy, push away negative thought"", she tok. Ashwenbom, wey be one of di pipo Yong helep tori e experience say di 'purpose diary' for write e story and make exercise weh e di komot e mind for negative tin and e say e promise say e go practice' am for house. For Yong, she wan use her story-telling campaign to raise awareness, how pipo fit heal demselves for society laik Cameroon weh plenti facilities no dey, focus for mind. ""Wen sabi pipo tok mental health, dia focus na education and physical health, deh di forget say everything di start for mind and na for deh e fit end, so we wan change, form peaceful mind set as we know say victim fit become warrior. We di transform dem from war victims for agents of sustainable peace"", de young leader tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49999455 +politics Edo State Governor Election 2020: Meet di former governors of Edo state and dia biography Ten govnors don rule Edo state since di creation of di state for 27 August 1991 wen dem divide di former Bendel state into Edo and Delta States. On di 19 of September 2020 wen pipo for di state go come out come vote, di state go either witness di emergence of a new govnor wey go rule di state for di next four years or di incumbent fit remain for office. Colonel John Ewerekumoh Yeri na Nigerian soldier wey serve as Military govnor of Bendel state between 1990 and 1991. Im continue as govnor of di state until January 1992 wen di den Military President General Ibrahim Babangida divide Bendel state into two - Edo and Delta states. Yeri na di first military governor of Edo state and e help di state move smoothly from military to civilian goment. For di speech im give for December 1991, im say Military Administration hold traditional rulers in high esteem, and di military expect say dem go teach dia subjects about Government policies and programs for grass root level. During im tenure, di administration bin invest for road construction for di state. During di election, Social Democratic Party (SDP) bin win di Gubernatorial election for di state. For January 1992, im hand over power give John Odigie-Oyegun. Dem born John Odigie Oyegun for August 12, 1939, for Warri, Delta State. Im serve as di first national chairman of All Progressives Congress (APC) for Nigeria. Im attend St. Patrick's College, Asaba, and e go University of Ibadan where he obtain Bachelor's degree in Economics. He then serve for various capacities as a federal civil servant wia im work as development planner. Dem elect Chief John Oyegun as civilian governor of Edo State on top di SDP platform, during di transition to democracy wey General Ibrahim Babangida launch and e rule from January 1992 to November 1993. Dem comot am from office after General Sani Abacha seize power. Later, e become di leader of di All Nigeria Peoples Party (ANPP). Col. Mohammed Abdul-Salam Onuka take over from di Civilian Governor of di state as di Military Administration of Sani Abacha start. Im serve as Military Administrator of di state from December 9th 1993 to September 14th 1994. Col. Onuka interest na for di Tourism sector of di state. E reason say di state get plenty tourist attraction site wey go yield revenue for di young Edo state if dem manage am well. Im bin try to develop di tourism potential wey dey di scenic area of Ososo but e no fit fulfil di dream of making Ososo tourist heaven before another colleague in uniform take over di leadership of di state. Colonel Bassey Asuquo na from Odukpani Local Government Area, Cross River State. Im serve as di military governor of Edo state from 14 September 1994 - 22 August 1996. Before im appointment, im serve as di Military Administrator of Delta State between December 1993 and September 1994. Im retire as Brigadier General for di Nigerian Army. Col. Asuquo na di Clan Head of Anim Ankiong Clan Council of Odukpani Local Government area in Cross River State. He testify before di House Committee on Power and Steel wey dey torchlight how dem take spend di money wey dem pay for di Calabar 561MW GT power station, he say na di contractors delay di project no be di community dey cause kasala on top di project. For September 2009 dem appoint am as di chairman board of di Federal Psychiatric Hospital, Calabar. Group Captain. Baba Adamu Iyam become di Military Governor on August 22 1996, di position e occupy till August 7, 1998. As im take ova leadership, im first sack 8,000 Edo state workers from service. Im no stop there, for February 1997, e stop all grants wey dey go Edo State University, Ekpoma as e tink say goment no suppose dey fund universities. Di academia and workers for di state no go quick forget wetin do dem during di regime of Adamu Iyam. Onyearugbulem bin comot di Peoples Democratic Party (PDP) and e declare im intention to run in 2003 for governor of Imo State on di All Nigeria Peoples Party (ANPP) platform. Later that year, Onyearugbulem die suddenly for im hotel room for Kaduna wey make pipo wonder wetin fit happun. During im time as di Military Administrator of Edo State, e join issues wit di Oba of Benin. Navy Captain Onyearugbulem suspend Oba of Benin on top claim say e endorse APP governorship candidate. Dem born Anthony Ibe Onyearugbulem for 9 July 1955 for Owalla Avuvu in Ikeduru, Imo State. E go school for St. Columbia's Secondary School, Amaimo (1970-1972) and Enyiogugu High School, Mbaise (1972-1974). E later join di navy. Lucky Nosakhare Igbinedion become di governor of Edo state under di platform of Peoples Democratic Party (PDP) on May 29th 1999 after democracy return. Dem born am on 13 May, 1957. Im rule di state from 1999 to May 29, 2007. During im reign, dem sabi am as di action governor as e clear di salaries dem owe Edo state workers especially Observer staff for 19 months. Dem go remember im administration for human capacity development. and for di fight against human trafficking and prostitution, di fight wey im wife Eki Igbinedion bin lead. After e comot office, di Economic and Financial Crimes Commission declare am wanted on January 2008 on 142 counts of financial fraud. Di allegations na say e embezzle 24 million dollars i.e 12 million pound using fake companies. Dem born am for October 5, 1951 in Iruekpen di present day Esan West Local Government Area of Edo State. On May 29, 2007, PDP produce Prof. Oserheimen Osunbor as di governor of Edo state. He serve as di Civilian Governor of di state from May 29, 2007 to November 11, 2008 becos court later nullify im election. Dem born Adams Aliyu Oshiomhole for 4 April 1952, im be di former national chairman of di All Progressive Congress. Oshiomhole bin serve as di president of Nigeria Labour Congress from 1999 to 2007 and di executive governor of Edo State, Nigeria from 2008 to 2016. As APC national chairman, dem suspend am from office by di Abuja Court of Appeal on 16 June 2020. https://www.bbc.com/pidgin/media-53950600 +entertainment How to apply for BBNaija 2021: Organisers announce season 6 audition, reveal N90 million worth of prizes Nigeria biggest reality show Big Brother Naija don announce audition date for season 6 wey dem say go get N90 million worth of prizes. Di N90 million worth of prizes dey bigger dan last year own wey be N85 million. Di organizers also introduce new twist wit early auditions wey dem say go begin from March 24 to March 31, 2021. According to di reality show official handles, dis auditions go dey strictly available to DSTV and GOTV users. But di organizers no give details wen di new season go start. Last year out of di 20 housemates wey enta di Big Brother house na Laycon emerge di winner of di Lockdown season. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56511384 +sports #EndSARS protest: Super Eagle Players wan shun AFCON qualifier sake of Nigeria violence "Super Eagles midfielder, John Ogu don tok say im fellow team mates for Nigeria football senior national team no go dey to represent di kontri for di 2021 Africa Cup of Nation double-header against Sierra Leone wey suppose happun next month. Ogu tok dis one as e bin dey react to di kasala wey burst for Lekki toll gate shooting afta sojas start to dey fire weapons for unarmed protesters on Tuesday. One player wey dey based for Belgium say im no fit to dey represent kontri wey dey kill im brothers and sisters. According to local tori pipo, Punch. E say make den end di killing and unrest or dem go stay away. Oda Nigerian players outside di kontri don join mouth put wetin happun on Tuesday. Manchester United Striker Odion Ighalo call di Nigerian goment say dem be ""a shame to di world say you kill your own citizens."" Former Super Eagles Captain, John Mikel Obi, for interview wey e follow BBC Pidgin don call am ""very sad time for our kontri"" and tok say di kontri as a whole need change from di top. Current Super Eagles Captain, Ahmed Musa say e dey unfortunate say Nigerians don lost di right to peacefully protest or exercise dia basic human right. Di goment need to do better and put an end to dis, Musa add. Tori be say di Super Eagles dey meet to find way to protest in support of Nigeria EndSARS protesters. However e neva clear weda dem don collabo say dem no go play for Super Eagles next few matches." https://www.bbc.com/pidgin/media-54649285 +politics Fashola ansa qweshion left, right and centre from Senators during ministerial screening "Nigeria former minister of power, work and housing Babatunde Fashola say, di towns of Michika and Madaghali for Adamawa state no get light sake of say some members of Nigeria military blow up di power station for di areas as part of dia war strategy to fight Boko Haram. Oga Fashola tok dis one as im dey ansa qweshion from Senator Isiaku Abbo wey dey represent Adamawa north wen bin wan know why some big towns for in state like Michika and Madagali still no dey for national grid since afta Boko haram attack di area. For im response to Senator Teslin Kolawole Folarin, wey say in dey disappointed say dem no fit finish Lagos to Ibadan express way inside four years, Fashola say di problem wey Lagos to Ibadan express way get na di same problem of funding wey all di roads projects for Nigeria get. E say no be say dem bin no wan do di road, but dem gatz to choose due to lack of moni. E also say anoda challenge be say di protocol to get moni from public private partnership (PPP) na long one and e no easy to show result inside four years. More dan 20 senators signify interest to ask Fashola qweshion on Monday wen im appear for senate for di continuation of di ministerial screening. Di senate don dey screen di nominees since last week afta President Muhammadu Buhari send di list give dem, but plenty pipo bin don dey tok-tok say dem no dey ask di nominees dem beta qweshion. Monday own show say no be business as usual afta Senate President Ahmed Lawan tok say im get 28 lawmakers ontop im list wey wan ask Fashola qweshion about im four years as minister. Di Former minister wey list some of im achievement as minister say im bin recover 720 abandoned containers wit transmission equipment inside wen im become minister for 2015. According Fashola di containers wey belong to di federal republic of Nigeria bin abandon for Nigeria Ports Authorities for almost ten years. Fashola add say im later distribute di equipment to more dan 100 substations for different parts of di kontri. E say dem don complete some of di substations before im leave office. Anoda nominee wey face di lawmakers on Monday na sister of di former Senate President Gbemi Saraki, but di senators no grill am as dem ask her to ""take a bow and go.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-49157073 +sports Asisat Oshoala na one of di 20 nominees for Women Ballon d'Or 2022 Asisat Oshoala don get nomination for di 2022 women Ballon d’Or to be best footballer of 2022. Di Nigeria Super Falcons and Barcelona striker afta her wonder season wit Barcelona Femini for di Spanish League. Oshoala score 20 goals inside19 games to share top scorer award wit Geyse Ferreira wey bin play for Madrid CFF last season but now be Oshoala teammate. Di 27-year-old game time bin dey limited last season because of injury but she show her quality in front of goalpost anytin wey she bin get di chance to play. Also, England Euro 2022 winners Millie Bright, Beth Mead and Lucy Bronze get nomination for di women's Ballon d'Or. Mead become Euro 2022 best player afta she win di Golden Boot award wey dem dey give to di tournament top scorer. Organisers go announce di Ballon d’Or winners on 17 of October. For di men, Lionel Messi, di seven-time men winner, miss out as 15 Premier League players get nomination. Messi win di award for 2021. Na 30 players in total dem nominate for di men prize and half of di names for dat list dey play for dis season Premier League. Real Madrid Karim Benzema, na one of di strong favourites for di list, but Messi no make am afta underwhelming first season for Paris St-Germain. England players Jude Bellingham and Bukayo Saka dey among 10 players wey dem nominate for di Kopa Trophy, wey dem dey present for di best performing player under di age of 21. Meanwhile, four Premier League goalkeepers - Alisson (Liverpool), Ederson (Manchester City), Edouard Mendy (Chelsea) and Hugo Lloris (Tottenham) dey run for di Yashin Trophy, wey France football dey present every year to di best performing goalkeeper. Cristiano Ronaldo (Manchester United, Portugal) Trent Alexander-Arnold (Liverpool, England) Karim Benzema (Real Madrid, France) Joao Cancelo (Manchester City, Portugal) Casemiro (Real Madrid, Brazil) Thibaut Courtois (Real Madrid, Belgium) Kevin de Bruyne (Manchester City, Belgium) Luis Diaz (Liverpool, Colombia) Fabinho (Liverpool, Brazil) Phil Foden (Manchester City, England) Erling Haaland (Manchester City, Norway) Sebastien Haller (Borussia Dortmund, Ivory Coast) Harry Kane (Tottenham, England) Joshua Kimmich (Bayern Munich, Germany) Rafael Leao (AC Milan, Portugal) Robert Lewandowski (Barcelona, Poland) Riyad Mahrez (Manchester City, Algeria) Mike Maignan (AC Milan, France) Kylian Mbappe (Paris St-Germain, France) Sadio Mane (Bayern Munich, Senegal) Luka Modric (Real Madrid, Croatia) Darwin Nunez (Liverpool, Uruguay) Christopher Nkunku (RB Leipzig, France) Antonio Rudiger (Real Madrid, Germany) Mohamed Salah (Liverpool, Egypt) Bernardo Silva (Manchester City, Portugal) Son Heung-min (Tottenham, South Korea) Virgil van Dijk (Liverpool, Netherlands) Vinicius Junior (Real Madrid, Brazil) Dusan Vlahovic (Juventus, Serbia) Asisat Oshoala (Barcelona, Nigeria) Selma Bacha (Lyon, France) Aitana Bonmati (Barcelona, Spain) Millie Bright (Chelsea, England) Lucy Bronze (Barcelona, England) Kadidiatou Diani (Paris St-Germain, France) Christiane Endler (Lyon, Chile) Ada Hegerberg (Lyon, Norway) Marie-Antoinette Katoto (Paris St-Germain, France) Sam Kerr (Chelsea, Australia) Catarina Macario (Lyon, United States) Beth Mead (Arsenal, England) Vivianne Miedema (Arsenal, Netherlands) Alex Morgan (San Diego Wave, United States) Lena Oberdorf (Wolfsburg, Germany) Alexandra Popp (Wolfsburg, Germany) Alexia Putellas (Barcelona, Spain) Wendie Renard (Lyon, France) Trinity Rodman (Washington Spirit, United States) Fridolina Rolfo (Barcelona, Sweden) https://www.bbc.com/pidgin/articles/c6pqj53lvjpo +sports Gambia vs Mali: Musa Barrow late penalty help Gambia collect one point against Mali Late penalty from Musa Barrow ensure Gambia collect one point against Mali for match wey video assistant referee take centre stage. Di Bologna forward goal for di 90th minute deny di Malians take home all three points afta dem too score from penalty wey VAR award as di match end 1-1. Ibrahima Kone bin don open di scoring for di 79th minute from di penalty spot afta Ebou Adams bin push Yves Bissouma inside di box. Both teams get four points each for Group F and go need play dia last group match before dem go fit know if dem follow qualify for di next round of di Afcon. Dia four points fit see dem qualify as one of di four best losers for di tournament. Mali control much of di first half but Di Gambia bin come close to break di deadlock, as Barrow hit di crossbar wit powerful free-kick from over 30 yards out and Ablie Jallow curl one shot go hit right-hand bar too as di ball bin don beat Mali keeper Ibrahim Mounkoro. For inside hot conditions, Scorpions keeper Modou Jobe bravely deny Adama Noss Traore and tip over Amadou Haidara curling free-kick for di second half, while Bissouma send im shot over. And, after referee rule say Adams stop Bissouma from connecting wit Adama Malouda Traore cut-back, Kone score im second goal of di tournament - afta im also net Mali winner against Tunisia from di spot. Di Sarpsborg striker now get 10 goals for eight internationals for di Eagles, wey don reach Africa play-offs for di 2022 World Cup. But di intervention from VAR no end dia as Ebrima Colley looped ball hit Bissouma arm for close range and referee Samir Guezzaz point to di spot once more after im check im monitor. Bologna forward Barrow side-foot di ball into di right-hand side of di net to spark celebrations for The Gambia. Di Scorpions go face Tunisia for dia final Group F game on Thursday, while Mali go take on Mauritania (both 19:00 GMT). https://www.bbc.com/pidgin/sport-60017311 +business Ghana rank top investment destination in West Africa - RMB Where to Invest 2021 Report Ghana don dey ranked di best country in West Africa to invest in, according to Rand Merchant Bank latest report. Wit de new category, Ghana outperform Nigeria, Ivory Coast, and Senegal dia west African neighbors. Ghana also be di sixth-best investment destination in Africa, according to RMD analysis on Where to Invest in Africa 2021. Operating environment, fiscal scores and development plans - na di basic key to investment-attractiveness in a COVID-19 world. Dis na wetin de Rand Merchant Bank's (RMB) Where to Invest in Africa 2021 use rank Ghana across de continent. De bank wey dey analyze investment opportunities say Ghana survived recession since demma start de Covid crisis on a stronger footing than some of dia African peers. RMB is the corporate and investment banking arm of FirstRand Bank Ltd., of which First National Bank Ghana is a member. According to author, RMB Africa Economist Daniel Kavishe, dis year's report assess de extent of de pandemic impact on coutries performance. De report note say Ghana economy managed to avoid a recession in 2020 and registered growth of 0.4% — outperforming de SSA economies, wey reduce by 3.2% on average. Dem see de construction, agriculture and services sectors as de main catalysts for strong 4.2% average growth between 2022 and 2023. For 2021 de economy don show steady recovery - with di GDP print in 2Q21 at 3.9%, supported by performance inside both de secondary and tertiary industries. De report project say over de next few years, oil production output go pick up in de near-term. Dis go dey supported by higher oil prices wey go encourage further oil exploration in Ghana, e add. E get similar expectations for gold production, wey dey further supported by goment efforts to stop illegal mining activity - thereby promoting de formal sector. https://www.bbc.com/pidgin/world-59086003 +sports Croatia knock out 'confident' Brazil from Qatar 2022 Fifa World Cup Brazil don comot from di Qatar 2022 Fifa World Cup afta dem lose 4-2 to Croatia on penalties. Di match wey tight from di beginning end 0-0 afta 90 minutes. Towards di end of di first of extra time, Paris Siang Germain (PSG) Neymar break di Croatian defence afta e conver one tight pass from Luaca Paqueta to put Brazil ahead. Di second of di extra time start wit Brazil still wit di lead. But on di 115 minutes Bruno Petkovic shock Brazil wit an equaliser. Na so di match end 1-1 afta extra time. For di penalty shoot out, Real Madrid youngtar Rodygo and PSG defender lose dia kicks for Brazil. E clear say Croatia na Brazil biggest opponent for di Qatar 2022 Fifa World Cup. Croatia 4-2 Brazil Nikola Vlasic score for Croatia Rodrygo lose penalty for Brazil Lovro Majer score for Croatia Casemiro score for Brazil Luka Modric score for Croatia Pedro score for Brazil Mislav Orsic score for Croatia Marquinhos lose for Brazil FULL TIME: Croatia 1-1 Brazil 120+2mins: Casemiro put im head for di corner but  Dominik Livakovic make a nice save. 120mins: Lovro Majer try im luck wit shot from long distance afta good pass. Croatia 1-1 Brazil 119mins: Dangerous play by Casemiro. Michael Oliver blows for a foul. 117mins: GOAL! Bruno equalise for Croatia 115mins: Neymar quickly takes the free kick with a short pass. 115mins: Bruno Petkovic make harsh foul becos e wan win di  o ball from im opponent. whistle. Brazil get a free kick. 114mins: SUBSTITUTION. Mislav Orsic enta for Marcelo. 112mins: Pedro make ggressive challenge and Michael Oliver blow for foul. 110mins: SUBSTITUTION. Ante Budimir enta for Borna Sosa. 109mins: Luka Modric break free but an opposing player clear di ball comot. 107mins: Ivan Perisic send cross, but e no locate any teammate inside di box. Poor delivery. 106mins: SUBSTITUTION. Alex Sandro enta for Eder Militao. Fred enta for Lucas Paqueta 106mins: SUBSTITUTION. Lovro Majer enta for Mateo Kovacic. Croatia 0-1 Brazil ET Secon Half 105+4: End of first half of extra time. 105+1mins: GOAL! Neymar score for Brazil 105mins: Rodrygo lay di ball to Danilo (Brazil), wey boot am go up. 103mins: Bruno Petkovic find Marcelo Brozovic unmarked on di edge of di box, but e shoot di ball go over di bar. 102mins: Mateo Kovacic produce poor pass. 101mins: Dominik Livakovic block Pedro effort from di edge of di box. 99mins: Rodrygo pass neat ball into  di box in di direction of Lucas Paqueta, di ball too fast. 97mins: Lucas Paqueta and Neymar try to force di Croatian defence open. 95mins: Danilo tip cross into di box, but nobody dey dia to use di pass. 94mins: Borna Sosa make rough challenge and Michael Oliver blow for a foul. 91mins: Long cross from di side to well-positioned Antony but di defender clear am. Croatia 0-0 Brazil 90mins: First of Exra time don start Croatia 0-0 Brazil 90+5'mins: Referee blow whistle to signal di end of di second half. 90+2mins: Rodrygo take di corner but only send am into di middle of Croatian defenders. 90+1mins: 4mins of added time 90mins: Neymar chip pass over di line of defenders but dem clear am. 89mins: Brazil defender clear Borna Sosa cross. 86mins: Eder Militao react well to get to di rebound and take a shot from di edge of di box. 84mins: SUBSTITUTION. Pedro enta for Richarlison 82mins: Antony try to find Lucas Paqueta, but e put too much power on di through ball. 80mins: Lucas Paqueta receive good pass and shoot from mid-range. Goalkeeper Dominik Livakovic make brilliant save. 78mins: Richarlison commit foul and Michael Oliver immediately signal free kick. 77mins: YELLOW CARD. MARQUINHOS chop card 76mins: Neymar control a reverse pass deep inside di box and amd knack di ball low but Dominik Livakovic push am go corner. 75mins: Ivan Perisic commit foul. Ref Oliver don warn di two teams to dey careful fit dia tackles. 72mins: SUBSITUTION. Bruno Petkovic enta for Andrej Kramaric. Mario Pasalic enta for Nikola Vlasic. 70mins: Ref blow foul against Antony. 68mins: YELLOW CARD. Casemiro chop card for bad tackle 66mins: Dominik Livakovic make brilliant save afta Lucas Paqueta attempt inside di box 65mins: Marcelo Brozovic hold down im opponent to stop im movement. Ref blow for foul. 64mins: SUBSTITUTION. Second change for Brazil. Rodrygo enta for Vinicius Junior. 61mins: Brazil defender clear di ball afta Luka Modric attempt to dribble past opposing player. 58mins: Andrej Kramaric and Marcelo Brozovic attempt to exchange short two-yard passes, but di opposition defence stop di flow. 56mins: SUBSTITUTION. Manchester United forward Antony enta for Raphinha. 53mins: Mario Pasalic try im best to cross into di box, but e no dey enof 51mins: OFFSIDE. Ref catch Andrej Kramaric offside 50mins: Josip Juranovic attempt to find im teammate wit a pass from outside di box, but di Brazilian defence quick stop am. 49mins: VAR dey check for potential offside. Ref say NO PENALTY. 48mins: OFFSIDE. Linesman raise im flag against. Vinicius Junior 46mins: Good save by Croatia goalkeeper, Livakovic 45mins: Croatia 0-0 Brazil Half Time: Croatia 0-0 Brazil 45+2': Ref end First Half 45mins: OFFSIDE. Andrej Kramaric time im run too early and di linesman raise im flag 42mins: Neymar fire shot from di free kick straight to di middle of di net, di goalkeeper catch am. 41mins: Michael Oliver blow afta Marcelo Brozovic kick Vini leg instead of di ball. 36mins: Richarlison go on solo run, but e fails to create chance 34mins: Croatia dey lead on possession at di moment. 31mins: YELLOW CARD! Marcelo Brozovic receive caution from di referee. 30mins: Ivan Perisic lack options so e play di shot by im sef from di edge of di box. 29mins: Neymar take free kick wey no dey accurate. 28mins: Josko Gvardiol make bad challenge and leave Michael Oliver wit no oda option dan to blow for a foul. Brazil get free kick. 25mins: YELLOW CARD! Danilo chop card afta e commit foul. 23mins: Casemiro play first-time effort from long range, but defender block am again. Corner kick for Brazil. 20mins: Vinicius Junior in di middle of di box, e look up and shoot but Croatia defender block am. 19mins: Andrej Kramaric shoot from outside di box, but dem block im effort 16mins: Casemiro attempts to slip di ball through di defence, but e no fit locate im teammates. 14mins: Ivan Perisic produce lovely ball into di penalty area but di defender manage to block am go corner. 11mins: OFFSIDE! Flag up against Richarlison 10mins: Good defending. Vinicius Junior try to find Raphinha inside di box, but di pass cut out. 8mins: Mateo Kovacic makes strong challenge and ref Michael Oliver blow for foul. 7mins: Josip Juranovic attempt to find di head of one of im teammates wit better cross into di box, but Brazil defender jump pass am 5mins: Vinicius Junior try im luck wit shot from outside but di keeper catch am wit ease 3mins: Casemiro manage to dispossess im opponent of di ball, but e commit foul in di process Croatia 0-0 Brazil 1mins: KICK OFF Croatia: Livakovic, Juranovic, Lovren, Gvardiol, Sosa, Modric, Brozovic, Kovacic, Pasalic, Kramaric, Perisic. Brazil: Alisson, Militão, Marquinhos, Thiago Silva, Danilo, Lucas Paquetá, Casemiro, Raphinha, Neymar, Vinícius Júnior, Richarlison. Brazil neva lose in four of dia previous meeting wit Croatia in all competitions. Croatia don lose four of dia five World Cup games against South American sides, wit a 3-0 win ova Argentina for 2018 as di only exception. Two of doz four defeats na against Brazil – 1-0 for 2006 and 3-1 for 2014 (both group stages). Since beating Germany 2-0 for dia final for 2002, Brazil don lose each of dia last five World Cup knockout stage games against European nations. Brazil dey look to reach di World Cup semi-final for di ninth time, wit only Germany. Na Real Madrid midfielder Luka Modric dey lead di progress of Croatia. Though na 37-years-old, Modric don already show why dem bin nominate am as one of di best players for di world. Dis Qatar World Cup fit be im last major tournament. Croatia players, Borna Sosa and Josip Stanisic bin missdi win ova Japan becos one sick and di oda get muscle injury. Brazil go dey without Gabriel Jesus and Alex Telles wey no go involve for di World Cup again sake of knee injury. Alex Sandro no go also play becos e still dey recover from a hip problem. Danilo dey set to kontinu for left-back. Dey refresh dis page for live updates https://www.bbc.com/pidgin/articles/c979m5v043po +business President Buhari wan collect another loan- See all di places wia Nigeria goment don borrow money from "Nigeria President Muhammadu Buhari don request di approval for anoda set of loans. Dis time President Buhari dey seek approval from National Assembly to borrow $4,054,476,863 and €710 million respectively. Di President request dey inside letter to di Senate, wia e explain sey di loan na part of di 2018-2020 borrowing plan. President Buhari also tell di lawmakers to approve grant components of $125 million. ""Di distinguished senate president fit recall say I submit one request on 2018-2020 borrowing plan for di approval of the senate for May 2021. ""However, in view of oda emerging needs and to ensure sey all critical projects wey FEC approve as of June 2021 dey incorporate, I hereby forward an addendum to the proposed borrowing plan. ""Di projects listed for di external borrowing plan go get dia financing through sovereign loans from di World Bank, French Development Agency, EXIM Bank and IFAD in the total sum of $4,054,476,863 and €710 million and grant components of $125 million,"" Senate President Ahmad Lawan read from di letter. According to di Debt Management Office Nigeria Public Debt Stock as at March 31, 2021 na N33.107 trillion. Dis one na before Senate approve Federal goment 2018-2020 external borrowing rolling plan of $8.3 billion and 490 million euros for July, 2021. Some of di organizations wey Nigeria goment don borrow money from na Di office for information wey dem publish on dia official website say ""di Total Public Debt Stock wey comprise di Debt Stock of di Federal Government of Nigeria (FGN), thirty-six (36) State Governments and the Federal Capital Territory (FCT) stood at or USD87.239 billion. Di Debt Stock also includes Promissory Notes in di sum of N940.220 billion wey di offcie issue to settle di inherited arrears of di FGN to State Governments, Oil Marketing Companies, Exporters and Local Contractors.""" https://www.bbc.com/pidgin/media-58560197 +entertainment Nickelodeon Kids Choice Awards: Emmaunuella, Ikorodu Bois, and Elsa Majimbo dey part 2021 nominees "Di ogbonge awards wey dem dey call di Nickelodeon Kids Choice Awards (KCA) don drop dia 2021 nominees list and may fans dey go gaga. Dis year nominees get pipo like Ikorodu Bois, Emmanuella, Elsa Majimbo, Bonang Matheba, Mo Salah, Master KG plus GhettoKids and more. Di competition dey tough for di Favourite African Social Media Star award wey some veterans and some fresh face wey ginger pipo all ova di world. Actor, comedian, Saturday Night Live legend — and Kids' Choice Award winner! — Kenan Thompson, na di host of di show wey go shele on Monday March 15. From now now, fans fit cast votes for Twitter and at KidsChoiceAwards.com, and for Screens Up app wey dey work for iPad, iPhone, and Android devices for di U.S. African celebrities plus fans go dey ready wella to vote for ""Favourite African Act"" and di ""Favourite African Social Media Star"" categories. Nigerian stars na im take over for di ""Favourite African Social Media Star"" part wey get Ikorodu Bois and Emmanuella as nominees from di kontri, den dem come get Elsa Majimbo from Kenya plus Ghetto Kids, Bonang and Wian Van den Berg. For di ""Favourite Africa Act"" category, dem get South African national rugby team captain Siya Kolisi, Zozibini Tunzi and Emmy-nominated South African actress Thuso Mbedu, den football sports star Mo Salah from Egypt and Sadio Mane from Senegal and den Ugandan singer Sheebah. Last year, South Africa Rapper Sho Madjozi win di title of ""Favourite African Act"" from di virtual awards." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55999739 +business Rising prices: How dem dey hit different nations? "Di price of ordinary goods, wey be food and fuel, dey increase for di whole world. Di reason na sake of poor harvest, Covid19 pandemic and shortage of natural gas, but na for some kontris - and regions - wey di tin dey affect pass. Many pipo for sub-Saharan Africa dey use cylinder of liquefied petroleum gas (LPG) as dia main fuel for cooking. However, gi price of gas dey go up well-well. For some regions of Nigeria, di retail price don increase more an double over di past year, according to di kontri National Bureau of Statistics. Many pipo dey go use firewood, charcoal dey cook or cheap abi even dirty kerosene. No be only say dis one dey harm di environment, e dey also harm di lungs of pipo asd dem dey cook. Rising oil prices don also push up di price of fertiliser, and di cost of transporting food from farm to shop and market. Dry weather don affect harvest for many African kontris, according to NASA Earth Observatory. Dis don also make prices go up. For ngola, price of food don rise by 36.4% over di past year, according to kontri National Institute of Statistics. Di United Nations estimate say Africa get 282 million undernourished pipo. For Malawi, di rising cost of living recently spark large anti-government protest. For December, thousands of pipo protest for Istanbul and for di south-eastern city of Diyarbakir against di rising living costs. Inflation rise by 36% last year, according to di Turkish Statistical Institute (TSI). Food price rise by 44% across di year and by 14% for di month of December alone. For Istanbul, thousands of pipo dey queue for bread for goment bakeries, wia dem reduce di price sake of say dem no fit afford to buy bread for privately shops. Bread price rise partially sake of increase in di price of fuel and fertilisers, but also because di Turkish goment don increase di minimum price of wheat and barley to support farmers' income. No be only food dey cost. According to di TSI, transport fare, trains and boat rise by more dan 50% for 2021. Household electricity and gas bill rise by 50% and 25% respectively. Goment dey usually try to control rising prices by putting up interest rates. Dis one dey make hard to borrow money and stop too much circulation of money. However, Turkey president Recep Erdogan don refuse to do dis, e say high interest rates ""nn evil wey make di rich richer and di poor poorer"". Last year, di president order Turkey central bank to slash interest rates. Dis one don affect di value of Turkey currency, di lira, to reduce by 45% against di US dollar, and push up di price of imported goods. Goment response to rising prices na to increase di minimum wage by 50%. Di economist Ozlem Derici Sengul, founding partner for Spinn Consulting for Istanbul, warn say di di inflation rate for Turkey go reach 50% by April. Di investment bank Goldman Sachs predict say e go rise between 40% and 50%. TELL US YOUR STORY: How your life don dey affected by increase in food prices? For Brazil, price for consumers dey rise by over 10% a year and fuel price don increase by 50%, according to di Brazilian goment Institute of Geography and Statistics (IGBE). Price of food rise by 14% last year, wit harsh weather wey cause shortages of daily foods such as rice and beans, as well as animal feed. Brazil get more cow dan any wia for di world, but price of meat don increase so much ova di past year wey be say 67% drop don dey for di number of pipo wey dey buy am, according to di Brazilian polling organisation, di Datafolha Institute. Di cost of light don also increase sake of di bad weather last year. Brazil hydro-electric power plants, wey dey generate most of di kontri energy, get to close down because water no dey and dis make household electricity tariff to go up one-fifth last year, according to di IGBE. Living standard for Brazil dey worse dan e don be before since 2012. Di Getulio Vargas Foundation, one research institute, estimate say out of di population of 213m, 27.7 million pipo dey live below di official poverty line of $49 (£36) per month. Food price dey over 20% higher dan e dey last year, according to di official Columbo Consumer Price Index (CCPI), because di island state dey struggle to finance import of essential foods. Di Covid pandemic mean say for two years, Sri Lanka no fit make money from tourism as dem dey do before. Because of dat, dia foreign currency reserve don go very low. Wetin goment do na to stop importation of food because commercial banks no get enough foreign currency to pay for dem. Dis one don cause shortages for shops and increase price for many regular such as rice, wheat flour and powdered milk. Price for gas for cooking don increase by 85% , according to di CCPI. To calm pipo wey dey vex goment launch $1bn relief package - including to pay and pension increase for goment worker. Dem also comot tax on some food and medicine and announce income support for dia poorest citizens." https://www.bbc.com/pidgin/world-60088510 +health Madagascar coronavirus cure: Ghana no request for Covid-Organic herbal medicine "Govment of Ghana on Thursday clarify say dem no request for de herbal medicine wey Madagascar develop as COVID-19 'cure' for testing. Ghanaians start dey mount pressure on govment after news of Madagascar President, Andry Rajoelina reveal say dem find herbal cure for de virus. Ghana Information Minister Kojo Oppong Nkrumah tell daily briefing for Accra say na Madagascar authorities reach out to dem to offer dem di Covid-Organic herbal medicine as support. Despite de lack of endorsement from WHO, Ghana wan do independent test on de what dis herbal cure dey like. ""We reach out to dem (Madagascar). We ask say make dem am available to us like all drugs"" Oa Nkrumah reveal. ""Food and Drugs Authority (FDA) and Centre for Plant Medicine go test am to proven efficacious, we can recommend it use"" he add. Some African countries already take stock of de said cure, but World Health Organisation (WHO) no endorse de medicine yet. Meanwhile, Ghana dey research for herbal cure too, Centre for Scientific Research into Plant Medicine talk BBC Pidgin. Launched as Covid-Organics, dem produce di drink from di Artemisia plant - di source of ingredient wey dem dey use for malaria treatment and oda Malagasy plants. Dem dey market am inside bottle and as herbal tea afta dem test am on less than 20 pipo over period of three weeks, na so di president chief of staff tell BBC. Di Malagasy Institute of Applied Reseach (Imra) don ""test am for two pipo and e don cure dia treatment"", according to president Rajoelina. Im add say ""dis herbal tea dey give results in seven days"". Oga Rajoelina say di kontri dey work wit foreign researchers to create di drink as injections. Madagascar as at Wednesday 6 May, get 158 confam case of coronavirus and 99 pipo don recover from di sickness and nobody don die, according John Hopkins University. Artemisia na herbal plant. One of di local names na Wormwood. Dis herb no dey new to pipo wey dey use am for different tins including for food and medicine. E popular with di treatment of malaria. BBC Pidgin reporter Mansur Abubakar say e common for north with di Hausa pipo wey dey call di herb Tazargade. Many pipo dey use am before for one ailment or di oda. Infact as Madagascar announce say na Tazargade dem use for dia herbal cure some mosques for Kano don tell dia pipo to make use of am for dia body as protection. 86 year old Aisha Musa wey dey stay Kano northwest Nigeria tell BBC say, all her life she dey use Tazargade herb for different things and e dey always dey by her side. ""As I dey tok to you now, Tazargade dey my side, I dey put am for water for my grandchildren to drink or burn am for charcoal for the smell to go round the house, e dey do a lot of things, cold and flu, fever and body pains.""Married women wey dey also face one problem or the other for bedroom dey also use am for north. World Health Organization (WHO) don advise pipo against di use of Covid-19 remedies wey dey untested. ""Africans deserve to use medicines wey dem test to di same standards as pipo for di rest of di world,"" na so WHO, di United Nations health agency, tok in for statement on Monday. ""Even if therapies come from traditional practice and natural, to establish if e dey work and dey safe e dey important for am to go through serious clinical trials,"" na so di statement add. Meanwhile, di African Union say dem dey discuss wit Madagascar wit aim to obtain technical data regarding di safety and efficiency of di herbal remedy. For attempt to reassure pipo and brush aside safety concerns, Rajoelina drink di Covid-Organics for di launch event and say e dey safe for children to take am. Meanwhile, President Andry Rajoelina say di reason pipo dey doubt im kontri herbal remedy for Covid-19 na because di cure ""comes from Africa"". ""If na European kontri dem discover dis remedy, shey many doubts go dey?''E tell France 24 and Radio France International inside interview. ''Di problem na say e come from Africa. And dem no fit accept say kontri like Madagascar, wey be one of di poorest kontries for di world, don discover dis formula to save di world,"" e tok." https://www.bbc.com/pidgin/52736039 +entertainment Ify Onwuemene Nollywood actress die from endometrial cancer "Nollywood actress, Ify Onwuemene, wey bin dey popular for her role for di sitcom 'Everyday People', don die of cancer. Na her colleague Gloria Anozie-Young, announce di news of her death for her Facebook page. For di post Madam Anozie-Young say di actress die on Tuesday May 25 afta she battle wit endometrial cancer. ""Ify don finally go to rest, today 25th May 2021. May her soul rest in perfect peace. Amen."" Na wetin Madam Anozie tok. ""Dem diagnose her with endometrial cancer. Dem remove her womb, but she don dey battle wit di sickness for many years now."" Na wetin she add put. Di actress also tok about Ify battle wit di disease and di kain treatment wey she receive before she die. For 2019, even after eight sessions of chemotherapy, di doctors tell her say she don reach stage 4. But we no dey sure if dem bin give her wrong diagnosis or dem being treat her wit di wrong chemo, because she bin still dey feel pains for her upper abdomen and her tummy dey bloated. According to di actress she say Ify spend more than N10m, her fellow actors donate join plus oda Nigerians but in di end in no yield much. Madam Anozie-Young say Ify family go release details of her burial arrangement" https://www.bbc.com/pidgin/sport-57252032 +entertainment Wetin Kanye West don lose so far sake of im antisemitism tok? "E don clear now say di sport brand Adidas don comot hand from dia partnership with black American superstar rapper, Ye, wey pipo also sabi as Kanye West. For statement wey dem release on Tuesday, dem declare say ""Adidas no dey tolerate antisemitism and any oda kain of hate speech, Ye recent tok-tok and actions dey unacceptable, hateful and dangerous, and dem go against di company value of diversity and inclusion, mutual respect and fairness"". With di partnership wey scata, Adidas go lose £217m for 2022 according to dem and dia shares for di fashion brand drop by 8%. All dis bin start wen Kanye West debut im ""White Lives Matter"" t-shirt for Paris Fashion week for September. Afta di event e Tweet one anti-semitic tok - wey be tok against Jewish pipo- say, ""sleep dey my eye tonight but wen I wake up, I dey go death con 3 on Jewish pipo."" E come go several interview to tok about how Jewish pipo wan control am. Na afta dis im tok tins begin scata. Meanwhile, oda brands wey don comot hand for im mata na Balenciaga, di Bank JP Morgan, and clothing shopping brand Gap. Wetin more Ye don lose sake of wetin e tok? According to di Adidas statement, ""adidas na di sole owner of all design rights to existing products as well as previous and new colorways for di partnership"". Although dem don comot dia name from di Yeezy brand, e fit be say dem go continue with di designs from di partnership wey dem don become sole owners of. Adidas don previously tok say di Yeezy brand collabo wey don last like 10 years na one of di most successful collabo for di company history. But even Ye before accuse di brand say dem tiff im designs for Instagram posts wey im don delete now. Ye don tok plenti times, say e take am four times for Forbes to add im name as part of dia billionaire list, but dem no waste time to comot im name. Dis na as di magazine don estimate say di loss of di Adidas partnership, don cut Ye net worth from $1.5bn to $400m. Di remaining of im net worth dey come from real estate, cash, im music catalogue and im 5% stake inside Kim Kardashian shapewear company, Skims. Forbes and Ye don dey kwanta for years on top weda im deserve position for di magazine list of billionaire sotay wen dem even add am finally, e accuse dem say dem put di wrong net worth and dem no fit count. Film and television production company MRC don tok say dem no go distribute di documentary about di rapper sake of im anti-Semitic tok-tok sake of say dem ""no fit support any content wey go loud di volume of im platform"". For statement on Monday, dem say, ""Kanye na producer and sampler of music. Last week, e sample and remix one tune wey pipo don dey sing for ova 3000 years, di lie say Jews dey evil and wan control di whole world for dia gain. ""Dis same song for di time of di Pharaohs, Babylon and Rome, dem do di acapella version, Spanish Inquisition and Russia Pale of Settlement carry am do acoustic, Hitler take di song electric. Now, Kanye don carry am mainstream for dis modern era."" Ye don previously do documentary with Netflix earlier dis year, wey dem call ""Jeen-yuhs: A Kanye Trilogy"" and tori be say dem no go comot am from dia streaming platform. No! Ye neva lose ownership of im Donda Sport Company. Na just say im two first signees for di company don say dem no dey do again. American football player Aaron Donald say na because wetin Ye do na di opposite of how dem dey live dia lives and dey raise dia pikin. Dis wan dey followed by basketball star Jaylen Brown wey bin say e go stay with di company before im come do about turn on Tuesday, release statement to ""terminate my association with Donda Sports"". Ye bin formally start di Donda Sports for May dis year and na di two athletes wey just comot hand bin first sign with am." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c1wg4np9l02o +sports Teams wey don arrive Qatar for Fifa World Cup 2022 Teams don begin arrive Qatar, ahead of di first ever edition of di Fifa World Cup for dia. Na 32 teams go compete for di tournament and dem dey in eight groups of four. Di tournament go officially begin on Sunday November 20 and end December 18. For di first time in di 22 editions, di tournament go happun for winter. Fifa make dis move to avoid to play for summer sake of heat during dat period. Checkout some of di teams wey don show for di Middle East kontri. Group A: Qatar, Ecuador, Senegal, Netherlands Group B: England, Iran, USA, Wales Group C: Argentina, Saudi Arabia, Mexico, Poland Group D: France, Australia, Denmark, Tunisia Group E: Spain, Costa Rica, Germany, Japan Group F: Belgium, Canada, Morocco, Croatia Group G: Brazil, Serbia, Switzerland, Cameroon Group H: Portugal, Ghana, Uruguay, South Korea Four matches go take place every day during di group stage, e go last for a 12-day period. Di winners and di pipo wey finish second go qualify for di round of 16. Just like Afcon, World Cup get third place match. Di third place match go take place for December 17. Di group games go take place across eight stadiums wey be: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cer4j4m9vnmo +entertainment Tega and Boma BBNaija: 'I apologise to my husband and everybody I disappoint' - Tega "Tega don apologise to her husband and everybody she disappoint for inside Big Brother Naija house. Inside video she post for her Instagram page, she say, "" I take full responsibility for my actions and I sincerely apologize to everyone wey I disappoint and to those wey no fit stand my actions while on di show. I dey truly sorry. To my husband; Babe, I know we don already talk about dis but I wan apologize again and also appreciate you for standing by me and giving me all di support I bin need to pursue my career."" She tok. Meanwhile, Big brother evicted housemate, Boma too also don tok say im intentions no be to date Tega. Im open up about di relationship wey im get wit im fellow housemate, Tega for di house for one interview e get wit Ebuka- di show host. Fans of di Big brother Naija reality show bin drag Boma for involving imsef in a sexual relationship wit a married woman-Tega- during im time for di house. Boma don face backlash as many pipo feel say im actions no dey morally upright. Boma tell Ebuka say, Tega na di boy's favourite, all di boys like her , ""She even better pass all di single girls wey dem carry come, e be like na dem really marry sef. All of us bin dey root for Tega heavily, because Tega dey always help me."" Ebuka bin ask Boma if im ever feel at a point maybe im need take a step back, Boma say 'no' because for am, Tega bin really dey dia wen di house dey boring for am. Im tok say even though im regret im actions now. ""E don dey late but I see am now, No be say I no wan own up to am or take responsibilities for my action. I be human and we dey make mistakes, na wetin make us be human be dat. But my intentions no be to take a married woman away, but to wia na?"", im tok. Talking about im stay for di house, di former Housemate say im dey happy to don make am dat far during di show and say im get incredible plans line up for di future. Tega wey be di first housemates to dey evicted out of di 15 housemates wey dey up for eviction on Sunday bin earlier say everything wey happun between im and Boma na just film show. ""Dat na di script we decide to play, we be good actors, we get good time and we get good show. I dey sure say una get good time from our feem?"" Tega tok dis one when di host of di show, Ebuka ask about her relationship wit Boma wey be pass normal friends own. For her exclusive interview wit di show host, she add say di whole drama start wen she get injury and Boma bin take care of am. We bin get conversation say make we just act am up. She maintain say na cruise, say dem two just dey play out a script wey dem agree to act out for viewers. Overtime Tega bin dey always mention say she go give her fans highlights for di house." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58479295 +sports Manchester United vs Arsenal: Match prediction, preview and team news Manchester United dey play Arsenal on Thursday night and dem fit go seven Premier League games without beating di London club for di first time in dia history. Also, Arsenal fit win consecutive league games for Old Trafford for di first time since February 1979. Di Gunners dey hope to set new club record if dem fit keep a fourth consecutive clean sheet for dis match. Manchester United captain Harry Maguire go dey available for today match afta e complete a one-game suspension. Di club dey also monitor Luke Shaw afta e miss two matches wit head injury, while Raphael Varane and Paul Pogba go still dey side-line. Granit Xhaka and Sead Kolasinac no go follow for di match. Arsenal midfielder Bukayo Saka dey doubtful for di premier league match wit Manchester united dis night. Saka no complete Arsenal last match wit Newcastle united wey make di coach comot am, put Gabriel Martinelli wey seal di win for di London club. Sabi pesin for English premier league, Mark Lawrenson say im dey happy as Man U fans don support dia stand-in coach Michael Carrick. And e also like wetin Carrick im sef do wit di squad against Chelsea on Sunday, wit Nemanja Matic, Fred and Scott McTominay. According to Lawro, Man U defence still no dey strong but dem fit build o dia improvement ahead of today match wit Arsenal. Di Gunners return to winning ways against Newcastle, and create plenty chance to score, but United wey dey play for home in front of dia new manager go wan prove sometin. Prediction: 2-1 https://www.bbc.com/pidgin/sport-59508327 +sports Ghana vs Comoros: Andre Ayew red card as Ghana finish bottom of Afcon Group C table Comoros don shock Ghana as dem defeat di four time Africa Cup of Nations winners 3-2 for Garoua, Cameroon. Di island nation first ever win for di tournament also confam elimination of Ghana from di Afcon as dem finish bottom of group C wit one point. El Fardou Ben Nabouhane bin put di islanders ahead early on, and Ghana den go down to to 10 men wen Andre Ayew collect straight red card afta video assistant referee rule say im foul Comoros goalkeeper Ahmed Mogni double di lead before di Black Stars fight back to equalise 2-2. Wit one point not enought for Comoros, Mogni tap in dia thrid for di 85th minute to give Ghana dia first ever group-stage exit for Afcon since 2006. Di result of dis game and di oda game for di group wey end 2-2 between Gabon and Morocco mean say di North Africans top di group wit seven points. Gabon come second wit five, Comoros finish third with three points while Ghana finish bottom wit one point. Ghana line-up: 16. Wollacott, 17. Baba,23. Djiku, 18. Amartey, 2. Yiadom, 22. Sulemana, 8. Kyereh, 5. Partey, 7. Issahaku, 10. A Ayew, 9. J Ayew Comoros line-up: 1. Ben Boina, 4. Zahary, 15. Youssouf, 12. M'Dahoma, 10. M'Changama, 22. Bakari, 7. Selemani, 17. Youssouf, 8. Bachirou, 20. Mogni, 21. Ben Nabouhane https://www.bbc.com/pidgin/sport-60043250 +business Ghana traders threaten demo if government no ban 'foreign retailers' "Ghana Union of Traders Association (GUTA) say dem go do massive demonstration against government if dem no enforce laws against foreigners operating for retail business in three months. President of de Association, Dr Joseph Obeng reveal sey if government no do something within the three months wey dem give, den en members go hit de streets. ""We go declare destiny day demonstration in three months, where we go forget all other laws wey exist sake of dem no see wana plea"" Dr Obeng talk traders den media for de market. GUTA President san add sey ""we for enforce de law to de latter, running a state no be brother and sister matter so sey you go talk sey Ghana den Nigeria be brothers and sisters, so you have sovereign laws but you no go implement am."" Tensions resurface for Ghana between local traders and dema Nigerian counterparts on Tuesday sake of retail business feud for Opera Square Market wey dey Accra. Some members of de Ghana Electrical Dealers Association, take force lock foreign-owned shops after dema claims say some Nigerian nationals dey operate illegally in de retail business. De local traders say dem do de lockdown so say government go enforce de law wey dey stop foreigners from de retail market. ""We dey tell foreigners sey make dem leave wana market. We not dey tell dem sey make dem leave de country"" one executive of de Ghana Electrical Dealers Association, Kofi Amanfo Ofori talk. National President of de Nigerian Union of Traders Association, Ghana (NUTAG) Chukwuemeka Nnaji, talk BBC Pidgin say ""de ECOWAS protocol dey gives all citizens of member states equal rights to do business, reside and establish a business in each member state."" ""We Nigerians in Ghana have de right to trade for any kind of business inside, de law dem dey quote no be not applicable to Nigerians"" Chukwuemeka Nnaji talk. But de Ghanaian traders insist dem want make government enforce Section 27 (1) of the GIPC Act which limits retailing in de country to only Ghanaians." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49108389 +sports Gold Cup: Miles Robinson score di winning goal for US to beat Mexico 1-0 for extra time "United States beat Mexico 1-0 for extra time to win di Concacaf Gold Cup for a seventh time. Atlanta United defender Miles Robinson head in di winning goal after 118 minutes for Las Vegas, im third international goal for im kontri. Di US win na dia first for di tournament for North American, central American and Caribbean countries since 2017. ""I no really know wetin happen - some crazy emotions but I dey happy we get di W,"" na so Robinson tok. ""We bin dey focus a lot on set pieces. I know say If I get any opening, I fit finish one and Kellyn [Acosta] put in a perfect ball so I just finish am."" Mexico - wey be di only nation wey don win di tournament more pass US - bin get best chance of di first half and one very good chance saved when US keeper Matt Turner save Rogelio Funes Mori header. Paul Arriola bin get chance for US to score Mexico but im hit outside of di post, although di miss no matter in di as im team still go on to win di match." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58053700 +entertainment Ernest Asuzu biography: Nollywood actor Ernest Asuzu popular movies before death "Nollywood actor Ernest Asuzu na popular face for Nigerian home video, musician, producer, director and television personality wey dey popularly known as 'El Cream'. Ernest Asuzu dey popular for playing criminal, hitmen roles for Nollywood movies. Di Nollywood actor enta limelight afta im act for one blockbuster movie ""Another campus queen"" in di 90s. Asuzu die on Tuesday afta e bin just faint all of a sudden, according to di president of di Actors Guild of Nigeria, Emeka Rollas. Tori be say Ernest Asuzu. di Nollywood actor wey blow for di 90s doon act in ova one hundred feems dem. Dis na Ernest Asuzu popular movies before im death: Royal War comot for 2009 and im [Ernest Azuzu] bin act di movie with Ini Edo, Van Vicker and Enebeli Elebuwa. Im character name for di feem na Ugonna. Dis 2004 action flick cause Ernest to act with Alex Usifo Omiagbo, fellow Nollywood badboy, Hanks Anuku, Lilian Bach and Jide Kosoko. E bin even get part two wey drop dat year. Di movie drop for 2007 and na Dickson Iroegbu direct am. Ernest Asuzu follow act di feem wit Richard Mofe Samijo, Mike Ezoronye and Stella Damscus. Pete Edochie and Justice Esiri na dem follow act for dis 2005 thriller wey Ifeanyi Onyeabor direct Dis 2001 Teco Benson directed action feem wey Ernest Asuzu act bin also feature actors like Hanks Anuku, Enebeli Elebuwa and Bimbo Manuel. Di movie land for 2004 and feature actors such as Ramsey Nouah, Joke Silva and Rita Dominic wit Ernest Asuzu. Ernest Asuzu act for di 2004 feem bin get Elivs Chuks as Director and Emeka Enyiocha, Zulu Adigwe and Anne Njemanze Di drama feem wey im [Ernest Asuzu] act for di part one and two bin also feature Desmond Elliot and Ashley Nwosu . My guy bin come out for 1999 and feature actors like Rita Dominic for inside. Di Teco Benason directed 2003 drama feature Rita Dominic , Hanks Anuku , and Robert Peters. Ernest Azuzu die at age 37, according to multiple sources. Late Azuzu latest work na one music Album wey im release for November 2020 wey im title ""The truth"". He launch di music album, wey be 7-track album for December 2020. Although im grow up Lagos State South West of Nigeria, Ernest hail from Imo State form di Southern part of di kontri. Before im death, Asuzu tell some local tori for December 2020 say im problem dey spiritual and say im dey plan a return to Nollywood and music after years of no show. Ernest Azuzu wife, Jennifer Asuzu, na for 2010, e marry her but e neva clear weda dem get pikin or not. For 2015, tori land say im bin get stroke and according to many sources im recover fine. E bin enta di news for 2016 on top fake death mata, and e enta Facebook dat time for social media to clear di air. Now, sadly but true true, Ernest Azuzu AKA 'El Cream' don die." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55831523 +sports Cameroon vs Ethiopia: Vincent Aboubakar goals give Cameroon 4-1 victory over Ethiopia Cameroon captain Vincent Aboubakar don dey top di list of highest goal scorer for di ongoing African cup of Nations (Afcon) 2021. Aboubakar two second half goals don make am get four goals for di competition. Im bin score two goals for Cameroon first match wit Burkina Faso on Monday wia di Indomitable Lions win 2-1. Karl Toko Ekambi also score two goals for di match - one for first half and di oda one for second half. Ethiopia wey start well for di first half lose concentration immediately di second half start. Cameroon don become di first kontri to qualify to di next round afta dia victory against Ethiopia. Di two teams bin meet for Afcon for 1970, wen Cameroon beat Ethiopia 3-2 and for 2016 Nations cup wia dem play goalless draw. Di match happen for Olembe Stadium for Yaounde. Second Half don begin Cameroon 1, Ethiopia 1. 47mins: Attempt save. Cameroon keeper save Firew Solomon attempt. 50mins: Nouhou Tolo win free kick for defensive half. 53mins: Goal! Cameroon 2, Ethiopia 1. Vincent Aboubakar score Cameroon second goal wit header. 55mins: Goal! Cameroon 3, Ethiopia 1. Vincent Aboubakar score again for Cameroon to make am three 56mins: Substitution for Cameroon. James Léa Siliki replace Jean-Eric Maxim Choupo-Moting. 58mins: James Léa Siliki miss anoda attempt for Cameroon to score. 59mins: Foul by Michael Ngadeu 62mins: Attempt save. Keeper save attempt by Karl Toko Ekambi on target. 66mins: Abubeker Nasir win free kick on di right wing. 67mins: Goal! Cameroon 4, Ethiopia 1. Na Karl Toko Ekambi score from di centre of di box to di bottom left corner. 69mins: Substitution for Cameroon. Clinton N'Jie replace Nicolas Moumi Ngamaleu. 71mins: Offside, Cameroon. Vincent Aboubakar try through ball, but André-Frank Zambo Anguissa dey offside and referee catch am. 72mins: Substitution for Ethiopia. Bezabih Melayu replace Mesud Mohammed. 73mins: Substitution for Ethiopia. Ahmed Reshid replace Ramadan Yusef. 73mins: Anoda substitution for Ethiopia. Shemekit Gugesa replace Dawa Hotessa. 79mins: No hat-trick for Aboubakar as dem replace am wit Stéphane Bahoken 83mins: Foul by Clinton N'Jie. 85mins: Ethiopia keeper bloack anoda goals attempt by André-Frank Zambo Anguissa. 86mins: Martin Hongla miss attepmy afta im shot from di centre of di box go too high. 87mins: Ethiopia midfielder Bezabih Melayu miss goal attempt from di centre of di box. 89mins: James Léa Siliki win free kick for di defensive half. 90mins: Collins Fai hit di bar afta im right leg shot. 90mins+1: Cameroon concede corner. Full Time: Cameron 4, Ethiopia 1 Kick off: Di game don start and na Jean Jacques Ndala Ngambo be di referee 1min: Abubeker Nasir win free kick on di left wing. 4mins: Goal! Ethiopia score Cameroon 0, Ethiopia 1. Dawa Hotessa score for Ethiopia wit shot wit im right leg from di centre of di box. 7mins: Yellow card for Jean-Eric Maxim Choupo-Moting of Cameroon for bad foul. 8mins: Attempt save. Keeper save Vincent Aboubakar shot. 8mins: Goal! Cameroon 1, Ethiopia 1. Karl Toko Ekambi header from di left side of di six yard box give Cameron equaliser. 10mins: Nouhou Tolo win free kick for di defensive half. 12mins: Yellow card for Martin Hongla of Cameroon for bad foul. 15mins: Nicolas Moumi Ngamaleu win free kick on di right wing. 15mins: Yellow card for Surafel Dagnachew of Ethiopia for bad foul. 17mins: Attempt miss. Martin Hongla right leg shot from outside di box go high. 19mins: Martin Hongla win free kick on di left wing. 21mins: Attempt miss. André-Frank Zambo Anguissa shot from a difficult angle and long range go high and wide to di right from a direct free kick. 22mins: Attempt miss. Abubeker Nasir of Ethiopia miss goal afta shot from outside di box. 24miss: Attempt miss. Dawa Hotessa right leg shot from di centre of di box miss go right. 25mins: Abubeker Nasir win ree kick for di defensive half. 27mins: Karl Toko Ekambi of Cameroon win free kick for di attacking half. 28mins: Attempt miss. Jean-Eric Maxim Choupo-Moting use left leg shoot from di centre of di box. 29mins: Nouhou Tolo win free kick for di defensive half. 32mins: Offside, Cameroon. Karl Toko Ekambi try im luck on a through ball, but Nicolas Moumi Ngamaleu dey offside. 34mins: Cameroon get corner wey Ramadan Yusef concede. 37mins: Nicolas Moumi Ngamaleu win free kick on di right wing. 39mins: Aschalew Tamene Cameroon anoda corner 39mins: Karl Toko Ekambi hit left post wit header from di centre of di box. 43mins: Amanuel Yohannes win free kick for di defensive half. 44mins: Ethiopia get corner wey Nouhou Tolo conceded. 45mins: Foul by Martin Hongla of Cameroon. 45mins: Substitution. Ethiopia. Firew Solomon replace Surafel Dagnachew. 45mins+1: Referee Jean Jacques Ndala Ngambo end first half. First Half end: Cameroon 1, Ethiopia 1. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59983771 +sports Commonwealth Games 2022: Chioma Onyekwere, Nigerians wey don win for Birmingham Chioma Onyekwere make history as di first Nigerian to win the Discus Throw gold medal for di Commonwealth Games. For her first appearance for di games, di 28-year-old wey also be di African Games and African Athletics champion, throw her season best of 61.70m for her fourth attempt to snatch di lead from Jade Lally of Britain. Di USA based engineer become only di second African female for di Games history to win gold afta Elizna Naude of South Africa do am for 2006 Melbourne games. Her compatriot Obiageri Amaechi also win bronze medal as she throw 56.99m. Dia victory togeda wit oda medals wey Nigeria don win, see di kontri balance for number 10 for di medal table of di ongoing Commonwealth Games for Birmingham afta Day five. Nigeria get a total of eight medals, currently. Before Chioma and Elizna medal victories, Weightlifter Adijat Olarinoye na im win Nigeria first Gold medal for di Games. She win gold medal for di women’s 55kg weightlifting, she also set new games record with a combined lift of 203. Edidiong Joseph Umoafia win bronze medal for men’s 67kg category weightlifting. Rafiatu Lawal win gold medal for weightlifting. She set three Commonwealth Games records for di women’s 59kg final, lifting 90kg for snatch, 116kg for clean and jerk, 206kg in total. Islamiyat Yusuf win Bronze medal for women’s weightlifting 64kg event, with 93kg for snatch and 119 for clean and jerk. Folashade Lawal win gold medal for di Women’s 59kg event, she set new Commonwealth Games record of 206kg for Weightlifting. Taiwo Laidi win Silver for women's 76Kg category of weightlifting, she lift a total of 216kg for snatch and clean and jerk category. Di Games go end on August 8, 2022 https://www.bbc.com/pidgin/sport-62405793 +sports Ese Brume: Profile of Nigerian long jumper wey win Bronze for Tokyo Olympics games Even though Blessing Oborududu become di first Nigerian to dey guaranteed of silver or gold medal, Ese Brume become di first and only Nigerian for now wey im name go appear for Olympic medal table. She win bronze for di women long jump event na Malaika Mihambo of Germany collect gold while Brittney Reese of USA collect silver. Ese take di bronze medal wit her best jump of 6.97m. while Mihambo jump 7.00m for her final attempt to register her best best jump of di season. Meanwhile di 2012 Olympic champion Reese wey bin dey lead wit 6.97m bin get one final attempt to reclaim her lead back but di American no fit match Mihambo jump afta she register 6.84m to collect silver. Tori be say for di 2016 Olympics games for Rio Ese na di only Nigerian athlete to reach di final of her event but den she finish for fifth position. Ese Brume from Delta State, wey dey for south-south of Nigeria. Dem born her for January 20, 1996. She be 25 years old. She win her first Olympics medal for Tokyo games wia she collect Bronze medal for Long Jump event. See some of her accolades for Athletics https://www.bbc.com/pidgin/tori-58068277 +entertainment BBNaija: Kiddwaya advice Ozo about im relationship wit Nengi "Fans of Big Brother Naija don begin react to di advice wey Kiddwaya give Ozo about im relationship with fellow female housemate Nengi. Kidd tell Ozo to ask Nengi to be im girlfriend. Im say ""I believe say she go get distractions outside."" And I no want you to dey wait without knowing her intentions. Na for inside di lounge on Saturday Kidd and Ozo bin rub mind wen di oda housemates dey play game. Kiddwaya also tell Ozo say ""Nengi na di kind of girl if her guy dey worried say oda guys dey give her attention and gifts she no go like am."" na wetin im add put But Ozo say im dey confident enough say im girl go like am even wit oda guys attention. Although Ozo don tell Nengi say im like her inside di house many times but she tell am say she no dey interested for relationship for now. Dis week six housemates dey up for possible eviction dis Sunday. Di Housemates wey dey up na Nengi, Laycon, Lucy, Vee, Trikkytee and Kiddwaya. At least one of dem go live di house tomorrow." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54044481 +politics Bayelsa election: Supreme Court dismiss APC application to review judgement "Supreme Court don uphold dia judgement for Bayelsa State governorship election. Di court say di application by the All Progressives Congress (APC) and dia candidate no get any merit and dem no get jurisdiction to review dia own judgement. APC bin file application for February 20 and ask di court to set aside some portions of im judgement. Di February 13 judgement bin spoil David Lyon inauguration and put Senator Duoye Diri of the PDP as govnor of Bayelsa State. Justice Sylvester Ngwuta wey preside on top di mata, allow all di lawyers to present dis case. David Lyon lawyer, Afe Babalola argue say make di court throway im earlier judgement wey sack oga Lyon and deny am im chance to become di Governor of Bayelsa state. Dat di judgement wey di court deliver no allow for fair hearing. Wole Olanipekun wey dey represent di APC for di mata, say di court get di power to review im judgement and e pray di court make dem throway di February 13, 2020 judgment. But Amina Augie wey deliver di judgement say, she dey disappointed say senior members of di bench go approach di court to set aside dia judgement. She say e no follow Nigeria constitution. Bayelsa State Govnor, Senator Douye Diri for im reaction to di Supreme Court ruling say na reflection of God judgement. Im say ""Once again, I describe myself as miracle govnor. So di Supreme Court just affirm di judgement of di Almight God, wey make am possible for me to become di govnor of Bayelsa State. ""For me, victor or vanquished no dey as dis victory na for all Bayelsans. No be winner takes all.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51647848 +entertainment Daddy Freeze and Oyedepo: OAP Ifedayo Olarinde beg Nigerian preacher Bishop David Oyedepo afta viral video wey shake table "Daddy Freeze, Nigeria radio broadcaster wey sabi shake table, don openly beg alias apologise to David Oyedepo, di founding Bishop of Living Faith Church, sake of di 'ínsult' wey im give di ogbonge pastor. Inside one short video ontop im social media page on Saturday night, Daddy Freeze wey real name na Ifedayo Olarinde, say im dey sorry for insulting Oyedepo about two years ago. Di radio on-air personality also yarn say im no get intention to dishonour and disrespect di 'man of God'. ""My attention don catch one video I release about two years, seven months ago while addressing some important issues wey bin happun back then,"" Daddy Freeze tok. ""I apologise for di way I take deliver di message and for any insult to Bishop David Oyedepo inside dat video as I bin no plan in any way to dishonour, disrespect or disregard di pesin of di bishop."" ""Di way pipo dey look my intention wey no be wetin I mean, dey regretted. My methods of addressing issues wey concern how Christians worship dia God alias doctrine don long since change to a more scriptural and less confrontational approach."" Daddy Freeze, di popular Nigerian broadcaster wey real name na Ifedayo Olarinde get old habit to always attack popular gospel preachers AKA 'men of God' for di west African kontri. On Monday September 7, Freeze enta news again afta popular Pastor David Ibiyeomie of Salvation Ministries for Port Harcourt, Nigeria, swear for am. Pastor Ibiyeomie say im no fit dey alive and Freeze go dey insult im 'papa', Pastor David Oyedepo. Bishop of Living faith Church Worldwide wey pipo sabi as ""Winners chapel"", David Oyedepo also follow for big big pastors wey Freeze don face. For September 2020, Bishop Oyedepo post for im verified Instagram page say di only way for marriage to dey fruitful na ""total submission from di wife"". Freeze counter am say submission na both ways, no be only for woman. Im add say wetin Bishop Oyedepo describe as submission sound like slavery to am. Di 44-year-old ogbonge broadcaster na pikin to Nigerian papa and Romanian mama. Im bin grow up for Ibadan, Oyo state for southwest of di kontri wia im also go school for University of Ibadan. For 1996, Freeze start im radio broadcasting career for Broadcasting Corporation of Oyo State (BCOS), Ibadan before im come move to Cool FM for 2001. As e be so, pipo for social media don begin hala for Pastor Ibiyeomie sake of di kain harsh word wey im use curse Freeze." https://www.bbc.com/pidgin/world-54136209 +sports "When is Nigeria vs Algeria match? Dis na ""Nigeria vs Algeria"" international friendlies review and everyin you need know" Nigeria vs Algeria friendly footbal match go shele on Friday 9 October, 2020. Dis match na to prepare for November Africa Cup of Nations qualification tie against Sierra Leone. Di game against di na di Super Eagles first international match of 2020 as Covid-19 ensure say all football-related activities dey on hold. Di game between coach Gernor Rohr men and coach Djamel Belmadi men go happun for Austria where di Nigerian team dey currently camp. Dis na di first time wey Nigeria go dey meet Algeria afta dem beat di kontri for 2019 AFCON for semi-final stage. Nigerian coach Rogr don put togeda footballers wey go play for d game and inside am be Maduka Okoye andlong two odas wey go be di goal keepers. William Troost-Ekong, Lyon Balogun dey di list among oda defenders. Di interesting tin about di list na say plenty new faces dey inside. Di new faces wey Nigerians fit sse for di match na Zaidu Sanusi, Yakubu wey be goal keeper, Tijani, Onyenka, Dessers wey get Bulgarian mother. Nigerian player with all di new faces dey camp dey train as dem dey prepare for di match. Cable company DSTV Nigeria go show di match live for channel 204 by 7:30pm local time. Algeria go clash with di three-time African champions for di fourth time for three years. https://www.bbc.com/pidgin/media-54456286 +health Coronavirus update: How Cameroon IDP women di produce masks weh CHRDA go share for fight Covid-19 "IDP woman dem for Centre for Human Rights and Democracy in Africa, CHRDA don produce 1500 of de 5000 for share'am for kontri pipo for Southwest region. Takang Olivia Tabot, na one of de IDP women weh e learn tailoring for Mamfe, but no bi fit bear de gunshots and for seka say security bi dey again, e decide for komot. Anglophone crisis start for 2016 till today, plenti pipo run go oda ares for kontri. Takang Olivia run kam Buea for wusai e start work wit Centre for Human Rights and Democracy in Africa, CHRDA. Now weh deh world di face di pandemic for Covid-19 and Cameroon get 855 cases and goment order make all man wear mask, Takang Olivia bi happy for help. ""Ma contribution na for design masks, dem change for use elastic for use bias for de masks dem weh de centre di share'am for pipo"", Takang Olivia tell BBC News Pidgin. Takang Olivia add say dey don make already 1500 masks dem and pipo di really admire de dia style. E good for note say masks dem really scarce and de one dem for pharmacy dear plenti. ""Just now ah get de feeling say ah di helep ma kontri pipo for sew de masks weh deh di givam for free but e di also e give me work."" As e own contribution for fight de disease, CHRDA use e IDP department weh e di try for teach young woman dem handwork for sew masks dash'am for population. Deh go start share de masks for population for CDC for Tole Tea plantation for Southwest region. Barrister Agbor Balla weh CEO CHRDA tell BBC News Pidgin say for make sure say de mask get quality deh take advice from doctor weh e tell dem de kana material for use'am. As Coronavirus pandemic spread for Cameroon CHRDA decide say dia community work for dis taim go bi for make masks de give'am free for population. But dis one no bi de first community support, as CHRDA support Tiko Council and deh di also sensitise pipo for wash dia hands wit soap and wata, di give out buckets and soap. Laik action join many odas for civil society for join hands wit goment for fight Covid-19 for kontri." https://www.bbc.com/pidgin/52290833 +health Coronavirus - Virus: Gaps dey inside Ghana preparedness against di virus - WHO World Health Organisation (WHO) say dem discover some gaps in de level of preparedness for Ghana in case de country get suspected or confirmed case of coronavirus. For dema assessment report inside, WHO say as at Friday, February 14, 2020, despite say government commit GH¢2.5 million for any eventuality, de amount no be enough. Di report say de total budget Ghana put aside to deal plus de deadly virus be GH¢35million. Despite de gaps, WHO score Ghana high on dema capacity to test for de disease for Noguchi Memorial Institute for Medical Research and de Kumasi Centre for Collaborative Research.WHO classify Ghana as one of de Priority 1 countries for Africa region which dey at risk sake of number if flights den passenger volumes de country de handle. Ghanaians make concerned say after dem record coronavirus case for Nigeria, Ghana for make steady sake of de number of people wey dey travel between de two countries. Ministry of Health for Ghana since de outbreak of COVID-19 den test 15 suspected cases so far, all of dem test negative. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51686830 +entertainment Luzuko Nteleko death: Actor Luzuko death at 36years 'shock' South Africans "Plenty pipo for South Africa don enta social media to mourn di death of popular South African actor Luzuko Nteleko, wey die at di age of 36 years old. Di family wey confam im death for inside statement say dem dey very sad as Luzuko mean plenty things to dem. “We dey deeply sad and hurt by im passing. Luzuko na pesin wey love. E be peace, courage and strength.” According to di family Luzuko bin dey diagnosed wit stage 4 brain cancer for 2019. E bin try to get well before e meet im untimely death on di 21st of June, 2021. Di family also add join say dem go communicate burial arrangements in due time. Di actor dey popular for feems like Zone 14, Streets of Mangaung, Isidingo and Ring of Lies. Reactions to Luzuko death As tori of im death begin spread, many of im colleagues, fans mourn im death and tok sorry to im family. Actor Thembisa Mdoda-Nxumalo for late Monday night share on social media say ""Each day, we lose one. Each day. E don take one special part of di art with am. Na only few pipo go understand. Go well mntase. ""#RIPLuzukoNteleko ""I dey lost for words afta dat kain big fight you pull, aaah mfe2. Di forever generous great smiling lion,"" Wiseman Mncube post. ""Oh Nomsa. I pray you find solace for di fact say im fight good fight. Find comfort for di memories una share.— Mpho Letsholonyane (@M_Letsholonyane). ""#RIPLuzukoNteleko I meet Zuko outside a casting for 2019, I ask am where I fit get taxi but instead dis broda give me lift straight go my house wey no even follow im route at all ..e no sabi me at all but dat no stop am. Rest in Power Bro — Mr OD (@ValentinoOdogwu) Lebenyatakatso Thuthu Sisi say, ""no sapho lonke, Mzantsi don lose one of im best talent. May his soul rest in peace."" Queen_tsholoI dey ""so sorry for your loss Nomsa. May his soul soar wit di the angels and your family comforted by di memories e leave for you."" Luzuko Nteleko na South African actor and entrepreneur wey pipo sabi well-well for im television roles as Loyiso on Zone 14 and as Student Constable on Streets of Mangaung. Di actor also features for some international productions and one of im latest international projects na LGBTQ US drama series wey feature US star Milan Christopher. E come from Sebokeng but di actor grow up for Johannesburg. Dem born am for 16 February, 1985. Luzuko study for Wits Tech. E get education/industrial theatre and Promotion Company. E understand plenty languages as e sabi speak Xhosa, Zulu, Sotho, Xitsonga and English. Im last post for Instagram na around April, “What shall I render to Jehova for He has done so much me.”" https://www.bbc.com/pidgin/tori-57572091 +sports Kelechi Nwakali: Huesca sack Nigeria midfielder 'for playing at Afcon' "Nigeria international Kelechi Nwakali claim say SD Huesca end im contract after im play for dis year Africa Cup of Nations against di Spanish club wish and im later turn down transfer in January. Di 23-year-old say im no ""go suffer in silence"" any longer as im make series of allegations against di club for statement wey im post on Twitter. Midfielder Nwakali allege say Huesca sporting director Ruben Garcia pressure am not to join di Super Eagles squad for January Nations Cup and di club been dey ""abuse dia power"" for attempt to force am to sign new contract, including say dem fail to pay im salary on time. Huesca ""completely deny and disagree wit di player accusations"" and say dem ready to defend themselves for court if di matter reach dat level. ""Di club at all times act wit di total respect for di player,"" one Huesca statement tok. ""Sake of di seriousness of some of di statements wey [di player] make, di club reserve di right to exercise any actions wey we consider as appropriate in defence of our legitimate rights and interests."" Di second-division club announce say dem don terminate Nwakali deal, wey bin dey due to expire at di end of dis season, on Tuesday but dem no give any reason for di decision. Nwakali final appearance for di club come wen im play against Girona on 2 January, before im travel out for international duty. Nwakali feature three times for Nigeria for Nations Cup wey Cameroon host, but im misse their last-16 defeat by Tunisia through illness. Im also claim say di club ask am to train alone after e return to Huesca on 1 February. Nwakali join Huesca from Arsenal for September 2019 and play 33 times during im time wit di club. ""All I want do na to go back to playing di sport I love,"" Nwakali add." https://www.bbc.com/pidgin/sport-61020155 +sports Transfer news and rumours: Osimhen, Sane, Havertz, Telles, Werner, Camavinga "Bayern Munich wan sign Manchester City and Germany winger Leroy Sane, 24, and e kontri man Kai Havertz, 20, from Bayer Leverkusen as part of ""new era"" for di club, na so dia deputy chairman tok. (Bayern 1, via Evening Standard) Chelsea dey lead Paris St-Germain to sign Porto Brazilian left-back Alex Telles, 27. (Tuttosport via Express) Lille don receive multiple offers for striker Victor Osimhen. Tottenham, Liverpool and Arsenal dey among di clubs wey dey interested in di Nigerian, 21. (Mail) RB Leipzig striker and Liverpool target Timo Werner don make clear im decision on e future on transfer toks, na so Inter Milan sporting director Piero Ausilio tok. Ausilio say di German 24, ""no go come join us"". (Daily Star) Arsenal na di favourites to sign Napoli and Poland striker Arkadiusz Milik, 26, but dem dey face competition from Juventus.(La Repubblica via Daily Star) Manchester United believe agent Mino Raiola na di only person wey want Paul Pogba to leave di club in di summer. France midfielder Pogba, 27, don dey linked wit Real Madrid and Juventus.(Times - subscription required) Rennes don rule out selling Liverpool and Real Madrid target Eduardo Camavinga dis summer. Di midfielder, 17, don dey linked wit Manchester United. (RTL via Evening Standard) Liverpool midfielder Harvey Elliott don turn down di chance to join Real Madrid. Di Englishman, 17, bin get invite to meet Sergio Ramos for attempt to get am to join di club. (The Athletic - subscription required) Barcelona go want £9m loan fee from any Premier League club for Brazil midfielder Philippe Coutinho. Di 27-year-old get transfer price of £71m. (Mundo Deportivo via Mirror) Atletico Madrid midfielder and Manchester United target Saul Niguez say e go ""announce new club"" in three days. Di Spain player, 25, get £130m release clause for e contract. (Manchester Evening News) Everton dey expected to bring back Denmark goalkeeper Jonas Lossl, 31, for di end of e loan spell for Championship side Huddersfield Town. (Yorkshire Evening Post) Celtic dey consider to sign Manchester City and Chile goalkeeper Claudio Bravo, 37. (Times - in Spanish) Chelsea manager Frank Lampard say im go ""refresh"" di club squad during di summer transfer window. (Mail) Inter Milan say dem wan keep on-loan Manchester United striker Alexis Sanchez beyond 30 June. Di Chilean, 31, get contract wit di Serie A side until di end of di season. (Sky Sports Italia via Talksport)" https://www.bbc.com/pidgin/sport-52874259 +entertainment BBNaija eviction show today: Jackie B and Jaypau chop eviction from di Big Brother Naija house "Jaypaul and Jacky B don be di latest housemate to dey evicted from di big brother Naija 'Shine Ya Eye' reality TV show. Jaypaul na im be di first to leave di house for today eviction, followed by Jackie B. Di two housemate wey leave di house today na based on say na dem get di lowest number of votes among di nominated housemate. During di live eviction show, Jacky B say her experience for di house dey amazing and she dey thankful for all di experience wey she get both di good, bad and ugly. Jacky B tell di show host, Ebuka say Whitemoney give am 'Daddy vibes,' Friend vibes' and dat na where she keep Whitemoney but she reveal say she like Michael. She later say she wan explore more new things like acting and start planning events afta di house. While Jaypaul say im dey grateful say e stay di house reach seven weeks and in short e dey grateful for every opportunity wey come across e life. E say im and Saskay dey on dia way to 'maybe becoming a thing' but e understand say Saskay get many situation to sort out. So if things work out fine, but if e no work out no wahala. Jaypaul say afta di Big Brother House, im go put body for a lot of TV shows, drop im music and go back to film school. Seven housemates na im bin dey up for possible evictions dis week and dem be; Jaypaul, Jackie B, Saga, Saskay, Liquorose, Whitemoney and Queen. Last week, Tega, Boma, Michael and Peace chop dia own eviction from di Big Brother Naija show. Among di seven housemates wey dey up for possible eviction, JayPaul get di lowest percentage of votes dat na, 3.77%. While Jacky B get 4.26% of di total votes from viewers wey vote. Saga wey get 8.28% votes and third for di lowest, for be di number three pesin wey for leave di house if to say Big Brother bin wan evict three housemates from di 'Shine Ya Eye' show. Jackie B na 29 years old proud single mum wey be interior designer and certified event and wedding planner. Jackie B attend university for UK and she like to dey have fun plus spending time with di pipo wey she love. She describe hersef as ""introverted extrovert"" and insist say she dey shy, but confident. Jaypaul na 29-years-old Lagos based musician and actor wey believe say di Big Brother Naija House na di perfect opportunity to help im career for Nigerian entertainment industry. E hobbies include making music, making movies, dancing and cooking. Jaypaul career means a lot to am. Meanwhile, a total of 11 housemates na im still remain for di Big brother season 6 'Shine Ya Eye' reality TV show afta today eviction. 26 housemates na im bin dey compete for di realty TV show and dem enta di house batch by batch. Di remaining housemates now na; Whitemoney, Nini, Liquorose, Saga, Emmanuel, Pere, Angel, Cross, Queen, Saskay and Yousef. Out of dis 11, only five go remain for di final week of di show according to di custom. So six more housemates need to comot before dat final week. Who e go be?" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58537353 +sports Afcon 2019: Wetin dey happun today Nigeria and Egypt qualify for di round of 16 for di 2019 Afcon wey dey happun for Egypt on Wednesday. Di three time African champions Nigeria, beat Guinea 1-0, to win dia second group match with goal from defender Kenneth Omeruo. While host nation Egypt nack DRC 2-0 with goals from Ahmed Elmohamady and Mo Salah. Senegal and Algeria go hope to build on dia winning start wen dem play today. Di number one ranked team for Africa Senegal, go play Algeria by 6pm, any of dem wey win di match don qualify for di round of 16. Na Madagascar and Burundi match go open show today for Afcon by 3:30pm. Madagascar bin play draw for dia opening group B match against Guinea, if dem win, e go boost dia chance to qualify for di round of 16. Burundi on dia part need to win to keep dia hope alive for di competition. Kenya and Tanzania match na im go close di show by 9pm, di two teams lose dia opening match for group C, both of dem go dey eye three points for dis match to give dem ginger to progress for di completion. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48783147 +entertainment Erica disqualified from BBNaija: See Ngozi Nlewedim journey and big moments wit Laycon, Kiddwaya and odas inside 2020 Big Brother house "Erica journey to win #85 million for di Big Brother Naija season 5 lockdown edition come to an end afta Biggie disqualify her say she violate di house rules for di third time on Saturday night. Dis disqualification mean say she no go benefit anything from di Big brother Naija show and dem go even count her as participant of di show again. Erica wey be Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London. She say she dey passionate to become big time celebrity, and dat na one of di reason why she bin contest to be housemate for di Big brother Naija show. E no hard for Erica wen she land for di house to become friends wit almost all di housemates. Some of di notable friendship she make na wit Tolanibaj, Laycon, Kiddwaya and Prince. Di moment she tell Laycon say she go just like make dem just be friends afta im declare im interest in a relationship. Even though she bin no plan to date anybody for di house, Erica find love interest in Kiddwaya. She tell her bestie for di house, Tolanibaj say. Even if Kiddwaya no dey di picture, she no dey attracted to Laycon. Wen things be like say e no dey clear for Laycon, he ask Erica to pick either himsef or Kiddwaya and stay wit di pesin instead of showing am signs like she dey interested in am. Laycon tok dis one afta Erica bin try to kiss am for one Saturday night party, afta she drink alcohol. Her relationship wit Kiddwaya follow come wit some fights wit housemates. One of dem na Wathoni. Erica bin confront Wathoni about her constant comments and tactics sake of Kiddwaya. She believe say Wathoni like Kidd and e dey make her act anyhow towards am. But Wathoni clear di air say na money she come win for BBNaija house, no be man. Erica also enta fight wit Lucy after she make comment say ""Erica na di head, Kiddwaya na di neck"" 'If di head no turn, di neck no go turn', Lucy add. Dis tok vex Erica sotee she confront Lucy. Erica become head of house for di show two times as she win di Head of House games. As Head of House, Erica bin get automatic immunity for di eviction show for those weeks and exclusive access to di Head of House Lounge. Ozo and Erica na im collect di first strike of di season. Biggie punish dem say dem dey whisper. Den, Erica, Kiddwaya and TolaniBaj collect strike also because dem break di Head of House (HoH) lounge rules. Di weekend wey start di palava, Erica vex before dia every Saturday party end. She first start to dey vex with Kiddwaya say e dey dance with Nengi. But Nengi clear Erica say she no dey interested in Kiddwaya. Na di mata Kidd, Erica, Ozo and Nengi go inside go settle before di party end den she face Laycon. She use strong words wen she dey warn Laycon say make e tell her wen she try to kiss am aside from di one time she bin high on alcohol, afta dat she also deny her deputy head of house to sleep for lounge as she pour water for im bed. For eviction night on di Sunday wey follow, Biggie issue Erica di third and final strike for breaking rules. ask her to comot from di BBNaija house immediately." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54054351 +entertainment Grammy Awards 2022: Angélique Kidjo beat Wizkid, Femi Kuti to win Best Global Music Album for Grammys "Beninese singer and songwriter Angélique Kidjo don win di Grammy Award for Best Global Music Album category. Di 61-year-old beat Nigerians Wizkid and Femi Kuti alongside oda nominees like Ghanaian Rocky Dawuni. Dis na Angélique Kidjo fifth Grammy win and she also don collect 12 nominations. Di Benin Republic singer, songwriter and activist, Angélique Kidjo don win Grammy Awards for Best Global Music Album category for 2014, 2015, and 2019. For her acceptance speech, Kidjo celebrate new generation of African artists wey dey come up to represent di African continent and also thank music greats wey don come before her. ""Four years ago I stand on dis stage, I bin tell una say di new generation of artists wey dey come up from Africa go take you by storm and di time don come,"" Kidjo tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60971687 +politics Northern governors meeting: Di forum condemn southern governors call to zone presidency to south "Governors from di 19 northern states for Nigeria don declare as unconstitutional di stand of their southern states colleagues say di kontri next president suppose come from dia region. Di govnors wey gada under di platform of di Northern States Govnors Forum for one emergency meeting dem hold for Kaduna state goment house on Monday condemn di statement, say e contradict di constitution. According to di govnors for dia resolutions, zoning of di office of di president as dia southern govnors dey call for dey against di provisions of di 1999 constitution amended. ""Di Forum observe say some Northern States Governors don earlier express views for a power-shift to three Geo-Political Zone for di South wit view to promote unity and peace for di kontri."" ""Notwithstanding dia comments, di forum togeda condemn di statement by di Southern Governors Forum say di Presidency must go to di South."" ""Di statement dey quite contradictory wit di provision of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria (1999) as amended."" Dem say according to di constitution, any president wey dey elected must meet di constitutional requirements wey include; Dia reaction dey come afta Southern Governors from 17 states earlier repeat dia position say di next president of Nigeria must come from di Southern part of di kontri in line wit politics, equity, justice and fairness. Another ogbonge issue dem discuss for di emergency meeting na di mata of Value Added Tax (VAT) wey some state govnors dey drag wit di federal goment on who suppose dey collect VAT. Di northern govnors say dem dey aware say di case still dey court and e no go dey okay if dem take decision on di issue. However, dem dey of di position say di southern govnors wey don express support for states to collect VAT dey confuse am wit sales tax and if every state make dia own VAT law, e go lead to multiple taxation. On di issue of security for di region, di northern govnors hail di military fight against bandits and insurgents for di area." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58713235 +sports Samuel Eto'o plead guilty to £3.2m tax fraud "Former Cameroon striker Samuel Eto'o plead guilty to £3.2m tax fraud in Spain. Di tax fraud mata get to do wit im image rights wen im bin dey play for Barcelona. Eto'o  wey be four-time African footballer of the year collect 22-month suspended prison sentence wen im show for court for Spain on Monday. Im be currently di president of di Cameroon Football Federation Dem say im must repay di money im dey owe, along wit fine of £1.55m. Prosecutors bin accuse Eto'o of failing to declare income from di transfer of im image rights between 2006 and 2009. Eto'o na di latest player to enta dis kain wahala. Oda foreign players and managers wey dem don prosecute for tax fraud for Spain in recent years, include Cristiano Ronaldo, Lionel Messi, Jose Mourinho and Neymar. Eto'o, bin play for Real Madrid, Inter Milan, Chelsea and Everton, before im retire for 2019. He appear for di Ciudad de la Justicia court in Barcelona wit im former agent Jose Maria Mesalles wey don collect 12 month suspended sentence and a fine. Di court hear say Eto'o transfer im image rights to a company based in Hungary. Tori be say day company declare im earnings inside dat kontri, wia di tax rate be one of di ""lowest in Europe"". Some go say Samuel Eto'o be one of Africa best footballers of recent times. Di Cameroon all-time top scorer - join Spanish giants Real Madrid for 1996 at di age of 16 before e go on loan for Leganes, Espanyol and Mallorca. Eto'o sign permanent deal with Mallorca for 2000, e score 54 goals inside 133 outings to establish imself as di team all-time leading scorer. E move to Barcelona for 2004 wia e win three La Liga titles, to epp di Catalans to two European Champions League wins for 2006 and 2009. And e score for both finals. For 2006, Eto'o become di first and only African to win di Spanish Golden Boot afta e net 26 times in 34 matches. Di forward score 108 goals in 144 games for di Nou Camp side before e join Inter Milan for 2009. For dia e win im third Champions League crown as well as Serie A title and di Fifa Club World Cup for 2010. Internationally, Eto'o epp di Indomitable Lions to win two successive Africa Cup of Nations for 2000 and 2002. Di footballer go on to become di tournament record scorer with 18 goals.For 2000, e guide Cameroon to Olympic gold medal, wia e score for di final. Eto'o dey now run football mata for Cameroon for di next four years." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4np23zygv9o +health Ghana start research project to find ‘herbal solution’ for Covid-19 disease "Centre for Scientific Research into Plant Medicine (CSRPM) for Mampong-Akuapem, start dey explore herbal solutions for treatment of COVID-19. ""De Center itself as research organisation dey do wana own projects which we hope say go fit support de immune system, provide symptomatic treatment or even find a solution for Covid-19,"" Baffuor Osei Akoto, PRO for Center for Scientific Research into Plant Medicine talk BBC Pidgin. Meanwhile, de Center also recommended nine herbal medicines which Ghana go fit use as immune support and supportive treatment for some symptoms Covid-19. De nine herbal medicines earn recommendation from de plant medicine research institute after dem subject dema products to scientific tests. Oga Akoto, explain give BBC Pidgin Favour Nunoo say dem recommend de nine herbal products for use as supportive treatment ""based on de initial test wey dey include microbial load analysis, acute toxicity test den phytochemical analysis of de products."" He explain say out of 33 herbal products wey de Centre for Scientific Research into Plant Medicine examine, only nine medicines wey show say dem fit support de immune system. De nine products be COA FS, Herbetine Herbal Powder, Herbetine Herbal Mixture, Viva Plus Powder, Ayisaa Opinto Herbal Tea, CD Capsules, Amen Depomix Powder, Amen Fevermix Capsules den Amen Chestico Capsules. Dr Kofi Bobi Barimah, Director, Centre for Scientific Research into Plant Medicine in a letter to de Minister of Health, Mr Kwaku Agyeman on reveal say these products pass dema evaluation tests. Dema studies reveal say herbal product like COA FS dey support de immune system fight a variety of diseases, wey chronic toxicity studies show say de drug did no get harmful effect on rats wey take am over a long period. ""Studies show say COA FS get anti-viral activity against HIV. Anecdotal clinical data collected show say COA FS dey reduce significantly viral loads in HIV and Hepatitis B patients"" Dr Kofi Bobi Barimah talk for de letter inside. Since de outbreak of Covid-19 pandemic, some African countries dey explore de use of herbal medicines for treatment while de world dey wait cure. So far Madagascar, wey come out plus medicine wey dem say go fit treat coronavirus. De nine herbal products wey Ghana recommend no be medicine wey dey cure Covid-19 but dem fit support de immune system to fight de virus." https://www.bbc.com/pidgin/52703548 +politics Ghana Election Special Voters list 2020: Voting in progress as Nana Akufo-Addo and John Mahama test popularity "Ghana Police, military, media, ambulance workers den essential service providers dey vote today ahead of 7 December 2020 election. Dis be special voting exercise wey Ghana Electoral Commission organise for key service providers who dey give critical service to Ghanaians on 7 December. Some 109,577 voters dey vote across de country from some 12 key institutions who de EC give dis right to vote first. Voting start today at 7.00am wey e go end around 5.00pm this evening. Electoral Commission for Ghana dey use backup biometric devices in case equipment break down during de special voting exercise. Ayawaso Central Electoral Officer for Gladstone Agboada, talk BBC Pidgin say dem get backup devices in case de devices mess up. All de special voting centers get backup biometric devices to help make de process smooth. Some 1063 voters dey take part in de special voting exercise for ATTC polling station, Ayawaso Central Constituency. Officials divide de polling station into A and B so say traffic go flow smoothly for de voting center. As at 9.35am officials talk BBC say dem record 200 votes, meanwhile more people dey queue inside dey wait for dema turn. All 311 voting centers for Ghana dey observe COVID-19 safety protocol in de ongoing special voting exercise. Electoral Commission of Ghana appoint COVID-19 ambassadors for de voting centers who dey ensure say voters wash dema hands, sanitize den stuff. According to the Electoral Commission, the exercise is taking place at 311 designated voting centres located in all the 275 constituencies. COVID-19 ambassador, Desmond Agyare for Osu Police Stattion which dey under de Korle Klottey Constituency talk BBC Pidgin say ""I dey make sure everyone wash hands and sanitize."" ""After I now go check dema temperature den make sure say dem wear nose mask before dem go meet electoral officers"" he add." https://www.bbc.com/pidgin/world-55138341 +health Monkeypox cases dey investigated in Europe, US, Canada "Health authorities don begin investigate cases of suspected and confam Monkeypox abroad. Monkeypox dey most common inside local areas for Central and West Africa, but now local media report am for America and Europe. Most recently dem confam one case for di US and dem dey investigate 13 suspected cases for Canada. Experts dey also look into cases for Canada, Spain, Portugal and di UK, according to local media report. Five infections dey confamed for Portugal as well as seven for Spain, health authorities tok. Dem dey always link di cases of di disease wey dem confam outside of di region to pipo wey travel go di area. Monkeypox na rare viral infection wey usually dey mild and most pipo dey recover from am in few weeks, according to di UK National Health Service. Di virus no dey spread easily between pipo and di risk to di wider public dey very low. Dem report di first case of di disease for di UK on 7 May. Di patient bin recently travel to Nigeria, wia dem believe say e catch di virus before e travel go England. Na wetin di UK Health Security Agency tok. So far dem don now confam nine cases for di UK. Dem neva confam di source but di di World Health Organization (WHO) say di cases dey ""locally acquired"" Dem don also report confam cases for Portugal and Spain afta dem alert European health agencies to di reports for di UK. And most recently, health authorities for di US state of Massachusetts confam one man don dey infected wit Monkeypox. Im bin recently travel to Canada, wia local media report say dem dey investigate 13 suspected cases of di virus. According to health officials, dem bin don hospitalise di man and e dey in ""good condition"" and ""e no pose any risk to di public"". Africa top public health agency tok am on Thursday say plenty plenty outbreaks of monkey pox for Africa don dey contained. E happun during di COVID pandemic even as di world attention dey oda places. He say di current outbreaks for Europe and di United States dey worry. Di acting director of di Africa Centres for Disease Control and Prevention say since 2020 outbreaks dem don see and contain di virus. Na for Democratic Republic of Congo, Nigeria, Cameroon and Central African Republic dem contain am. ""During dis pandemic, we don get many several outbreaks of monkey pox on di continent.... ""We also expect say oda outbreaks go come and we go handle am in di usual way."" Ahmed Ogwell Ouma tok am for one weekly news briefing. Ouma add say: ""We however dey concerned at di multiple countries outside, especially for Europe, wia we dey see dis outbreaks of monkey pox. ""E go be very useful if dem share knowledge regarding wetin really be di source of dis outbreaks,"" e tok. Monkeypox na rare but potentially serious viral illness wey dey start wit flu-like illness and swelling of di lymph nodes. Di sickness go later progress to a widespread rash on di face and body. Most infections dey last 2-4 weeks. Monkeypox na di same family of viruses as smallpox but dey cause a milder infection. CDC show say di patient dey infected wit a strain of monkeypox most commonly seen for parts of West Africa, including Nigeria. Infections wit dis strain of monkeypox fit kill about 1 out of 100 pipo. However, rates fit dey higher in pipo wey get weak immune systems. Before dis current case, US bin get at least six reported monkeypox cases in travelers wey dey return from Nigeria (including cases for di United Kingdom, Israel, and Singapore). Dis new case no dey related to any of dis previous cases. For di United Kingdom, several additional monkeypox cases dey happun in pipo wey get contact wit cases." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61511611 +sports Premier League fixtures: Brentford vs Arsenal prediction plus all di matches dis weekend for EPL Di Premier League don come back - and so too be Lawro. Lawro na former Liverpool defender and BBC football expert wey go make predictions for all di 380 top-flight matches dis season, against different guests. For dis opening weekend fixtures, im dey up against singer-songwriter Louisa Roach, aka psych-pop band She Drew the Gun. Louisa na lifelong Everton fan and former season ticket-holder wey start to dey watch dem just before dem win di FA Cup for 1995, and don dey wait to see dem win another trophy ever since. Make we start first wit di teams wey go open show on Friday. Brentford rise to di Premier League dey incredible and dem be great model for oda clubs to follow. Dia policy of finding and developing young talented players early, dey work for dem. Lawro prediction: 1-1 Louisa prediction: I feel say e go dey tough for Brentford. 0-2 Man Utd v Leeds Utd (12:30 BST) Manchester United fit play Anthony Martial for middle because dem dey miss Edinson Cavani and Marcus Rashford. I dey look forward to see Jadon Sancho in action - I feel everybody except for Leeds fans. Dis game go dey close pass di 6-2 win wey Ole Gunnar Solskjaer side enjoy at di end of last year, but I still dey expect dem to take di points. Lawro prediction: 2-1 Louisa prediction: Goals go plenty for dis one 4-2. Burnley vs Brighton Burnley lack of activity for di transfer market don start to dey worry me. Again, dem neva do too much dis summer and dem only spend money on getting Nathan Collins from Stoke. I dey go with Brighton to win this. Lawro prediction: 1-2 Louisa prediction: Dis game no go sweet, sorry. 0-0 Chelsea vs Crystal Palace New Crystal Palace boss Patrick Vieira don sign few players, including Michael Olise from Reading, wey be really promising young player. I still dey go wit Chelsea here, mind you. Dem already don get a competitive game dis week, di Uefa Super Cup final, wey go help them a lot. Lawro prediction: 2-0 Louisa prediction: 2-0 Everton vs Southampton New Southampton striker Adam Armstrong don take di same route as Alan Shearer, to play for di Saints, Blackburn and Newcastle, just in reverse. Dis na big game for Everton because na Rafa first as manager, and di crowds dey return so dis go help. I dey expect am to start di season wit a win. Lawro prediction: 1-0 Louisa prediction: To get di fans back go make a big difference for us. 3-1 Leicester vs Wolves I no really dey sure what to expect from new Wolves boss Bruno Lage, but we know wetin Leicester go try and do - attack them. Lawro prediction: 2-0 Louisa prediction: 1-1 Watford v Aston Villa Aston Villa look team wey don establish dia self for Premier League and I feel say dem go carry on even though Jack Grealish don port go Manchester City. Danny Ings na good signing and dem get some strength in depth. Lawro prediction: 0-2 Louisa prediction: 0-2 Norwich City vs Liverpool (17:30 BST) Na nice feeling for Jurgen Klopp to get some options for defense again but if Virgil van Dijk dey fit and ready I go bring am back in for dis game, rather than wait longer. You gtaz pick your best team, and im presence on and off di pitch dey massive. Lawro prediction: 0-2 Louisa prediction: I support Everton, and whoever dey play Liverpool! But I dey try to beat Lawro here, so I gatz go wit them to win. 0-3 Newcastle v West Ham (14:00 BST) Newcastle dey play for dia home wit di crowds wey dey return back for St James' Park e go make sense on paper, but which reception dia manager Steve Bruce go get? I no know. Magpies striker Callum Wilson dey fit e go help them, but I feel say West Ham go collect something for dis game. Lawro prediction: 1-1 Louisa prediction: David Moyes dey do a good job wit West Ham. 1-2 Tottenham v Man City (16:30 BST) We no fit tok about dis match without mentioning Tottenham striker Harry Kane. I no think say Kane go dey able to play dis game because him neva train wit im team-mates all week but di bigger issue na say nobody know which of these teams him go play for by September. As for di game, Manchester City dey without di injured Phil Foden but dem no dey lack creative attacking players, are be? Lawro prediction: 0-2 Louisa prediction: City go come out really strong. Dem go probably win di league. 0-3 https://www.bbc.com/pidgin/tori-58197304 +sports Indonesia football stampede and eight oda times pipo die for stadium incident "At least 174 pipo don die inside crush wey happun for one Indonesian football match wey don become one of di world worst stadium disasters. About 180 also injure afta home team Arema FC loss to dia bitter rivals for di overcrowded stadium late on Saturday for Malang, East Java. Di crush happun afta police tear-gas fans wey run enta di pitch. As panic spread, thousands move towards Kanjuruhan stadium exit dem, na for dia many suffocate. At least 129 pipo don die for one stampede for one Indonesian football match, officials tok. One eyewitness tell BBC say police bin fire plenti tear gas rounds ""continuously and fast"" afta di situation with fans become ""tense"". Di kontri chief security minister tok say di number of pipo wey come watch di match pass di capacity of di stadium by around 4,000 people. Videos show fans dey run on to di pitch afta di final whistle. Police kon fire tear gass wey lead to crowd stampede and cases of suffocation, Nico Afinta wey be police chief for East Java tok. ""Di mata become anarchy. Dey start to dey attack officers, dem damage cars,"" e tok, and add say two police officers dey among pipo wey die. ""We go like tok say... no be all of dem act anyhow. Only about 3,000 wey enta di pitch,"" e tok. Fans wey dey run ""go out to one point for di exit. Den build-up kon dey, for di process of accumulation shortness of breath dey, lack of oxygen"", e add. Videos on social media show fans dey climb di fences to escape. Oda videos appear to show deadi bodi for ground. Fifa, wey be di world governing football body, tok say make stewards or police no use ""crowd control gas"" for matches. Di Indonesian football association (PSSI) say dem don launch investigation, and dem add say di incident don ""tarnish di face of Indonesian football"". Violence for football matches no dey new for Indonesia, and Arema FC and Persebaya Surabaya na long-time rivals. Dem ban Persebaya Surabaya fans from buying tickets for di game sake of fear of clashes. But Chief Security Minister Mahfud MD bin post on Instagram say 42,000 tickets don dey sold for di match for Kanjuruhan stadium, wey get capacity of 38,000. Di top league BRI Liga 1 don dey suspended for one week. Di stampede na di latest for long line of disasters for stadiums. For 1964, total of 320 pipo die and more dan 1,000 injure during one stampede for Peru-Argentina Olympic qualifier for Lima, wey be capital of Peru. For UK, 96 Liverpool fans dey crushed to death for 1989 for di Hillsborough Stadium for Sheffield. For October 2010, one stampede among football supporters for Kenya kill at least seven pipo as dem try to get into stadium to watch match between two of di kontri most popular teams. One Red Cross official say six of di fans die for di Nyayo National Stadium for Nairobi and di last one later die for hospital. For May 2014, fifteen pipo die for one football stampede for one football final for Kinshasa, capital of di Democratic Republic of Congo, officials tok. Di kasala start towards di end of di game wen di home team AS Vita bin dey lose 0-1 to TP Mazembe. Di home fans begin to throw stones on to di pitch. Police kon fire teargas to try and stop dem, and di crowd panic and kon begin to push towards one exit. Anoda 10 pipo dey injured as pipo dey crushed for di pandemonium. At least 17 pipo die for one stampede for one football stadium for northern Angolan city of Uige for February 2017. Hundreds of pipo also injure wen supporters storm di gates afta dem fail to gain entry. Some of di pipo wey fall bin dey trapped and suffocate for di venue, one medical official tok. Witnesses tok say di crowd wey dey try to gain access fit don fill di stadium beyond di 8,000 capacity. Santa Rita de Cassia bin dey host Recreativo do Libolo for first division league match. Eight pipo - including seven children – die for one stampede ahead of one football match for Malawi for July 2017. Dozens of pipo also injure for di crush for Bingu national stadium for Lilongwe. Di stampede happun as thousands of pipo rush for seats ahead of one friendly between top sides Nyasa Big Bullets and Silver Strikers. Despite di deaths, di match bin go ahead and pipo plenty, although President Peter Mutharika no attend as im bin plan. Im offer im condolences and tok say di goment go do everytin dem fit do to assist di families of pipo wey die. For September 2017, five football fans die for one African Champions League tie for Angola. Di incident happun for Luanda as Primeiro de Agosto draw 0-0 wit TP Mazembe of DR Congo for di first leg of one Champions League quarter-final. Witnesses tok say di stampede happun afta fans see say di gates of di Estádio 11 de Novembro stadium dey shut afta di match. Wen police open di gates, fans bin rush out and some of dem bin dey trampled under police horses. At least eight pipo die inside stampede wey happun for Olembe stadium as dem bin dey play Africa Cup of Nations match for Cameroon for January 2022. Several odas also injure for di stampede. Di pipo wey die include one 14-year-old boy and seven pipo wey seriously injure. Cameroon President Paul Biya bin order investigation into di crush and send im ""deepest condolences"" to di victims' families. One video footage show as football fans bin dey struggle dey scream as dem dey crush dem for di entrance to di Paul Biya stadium for di neighbourhood of di capital Yaoundé. If we use previous stampede incidents take judge di mata, di major factor wey dey cause di stampede na fear among football fans afta police fire tear gas sake of unruly behaviour of some fans wey run enta pitch. Wen police fire tear gass, pipo dey run helter-skelter and some of dem dey suffocate and fall for ground while pipo go begin crush dem." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c1wnwl4vxw0o +entertainment Public Holidays in Nigeria 2022: Bank holidays, Easter date, Labour day, Eid al-Fitr 2022 work dey resume from Tuesday 4 January, afta di new year day and Christmas festivities wey mark di end of 2021. Public Holidays in Nigeria dey up to 20 times for 2022, and for some Nigerians e already dey for dia minds to plan dia diary to joli di new year. And yes, many dey look forward to di better things wey di year 2022 cari come including public holidays for di year. Dis holiday mean say banks, businesses, schools and goment offices no go dey open dat day. Dis na di likely public holidays wey di year 2022 cari for Nigeria: If any public holiday fall for week end, dem go declare di following week day as Public holiday. Dis na according to how Nigeria Ministry of Interior dey announce public holidays over di years. Na to compensate for di weekend wey pipo dey already dey accustomed to rest from work. https://www.bbc.com/pidgin/world-59860594 +politics Uganda elections 2021: Bobi Wine, di pop star wey wan unseat President Yoweri Museveni afta 35 years in power "E neva get anytime wey peaceful handover of power don happun for Uganda, but pop star-turned-politician Bobi Wine dey hope to change dat by unseating long-serving President Yoweri Museveni for Thursday's vote. BBC Africa correspondent Catherine Byaruhanga take a look at di challenger. Few weeks before di general election and wetin fit be di biggest day of Bobi Wine life as he bring im presidential campaign to im family ancestral home. Di 38-year-old pop star, wey im real name na Robert Kyagulanyi, gain im popularity for di informal settlements of di capital, Kampala, but even in Kanoni, one sleepy rural town for central Uganda, dem dey support am. Hundreds of young pipo, mostly men dressed in red, seem to comot from di bushes and gardens and surround im motorcade. Bobi Wine, wey dem dey also call ""ghetto president"", climb through di sunroof of im white Toyota Landcruiser and wave at di crowds - and dey ansa. For one unlikely dressing move for a presidential candidate, he don start dey wear bullet-proof vest and protective helmet. For December, dem shoot one bullet through im car windscreen narrowly missing one passenger. Bobi Wine say im think say im life dey in danger. For Kanoni, as e don happun many times during campaign , he don run into police and military blockade- dem fire teargas and bullets- Authorities say dem dey try find and disperse crowds and enforce Covid-19 guidelines. But Bobi Wine believed dis na yet anoda sign of intimidation. He don consistently dey tok say dis no go happun as im feel say im be head of a mass movement. ""Pipo no just dey follow me. Pipo dey follow di ideal wey I represent,"" he tell BBC in 2019. ""I no start am and I no go end am. I be just one of di millions and millions of Ugandans wey want beta"" Di manifesto of im National Unity Platform (NUP) party dey geared towards basic needs like improving access to healthcare, education, clean water and justice. All of dis, di NUP tok say dem fit only do am, if dem remove President Museveni from power. Ova di last two decades Bobi Wine musical output don dey been filled wit songs about dis issues and e don inspire one ogbonge following. Twenty-three-year-old law student Marion Kirabo dey campaign to be local councillor and she be one of im supporters. ""Even before im political life he be pesin wey di the youth fit identify wit,"" she tok. ""Especially through im music, you fit clearly see say he understood di social issues wey young pipo dey face, especially young pipo wey come from ghetto."" Wen President Museveni came to power for 1986, Bobi Wine dey just about to turn four, and e dey live for Kanoni. Central Uganda don be di battleground of di bush war wey bring Oga Museveni rebel National Resistance Army, and im political wing, di National Resistance Movement (NRM), to power. Bobi Wine grandpapa, Yozefu Walakira, dey part of one different rebel contingent but from time to time during di conflict wey Oga Museveni host for im house. Walakira die during di civil war afta im wunjure wen dem bomb im house - an attack wey also kill three family members. Bobi Wine family later moved to Kampala, im mama Margaret Nalunkuuma, wey be nurse, na di main breadwinner and she buy land for di Kamwokya slum wia di musician live and build im world-famous recording studio. Some of im primary and secondary schools always dey within walking distance from Kamwokya. As a teenager he discover im passion for di arts, but wen he first attend di prestigious Makerere University he start to dey study for social sciences degree. After one semester he switch courses and begin music, dance and drama, wia im get diploma from di university for 2003. For 2017, di reggae star turn im hand to politics as he see am as di logical next step. ""You know, all through my musical career, I don dey sing about di challenges wey pipo dey go through,"" he tell BBC. ""So e look like say I don dey campaign all my musical career."" Im song Tuliyambala Engule (We Shall Wear di Victor's Crown) don become one of di campaign unofficial anthems. He win by-election to become MP for Kyaddondo-East, one constituency to di north of di capital and even though an independent he align himself with di opposition. for one series of by-elections he campaign for candidates wey defeat hopefuls from di NRM. E no get any sound of regret for Bobi Wine voice wen he reflect on im rival career inside one BBC interview for 2019. ""Why dat kain prized revolutionary decide to become one of di world's most despised dictators?"" he ask. ""But na also lesson to many of us, as we sabi say we dey tok wetin President Museveni dey tok wen e dey like us. And also to remember say na only di idea of building strong institutions fit save us from ourselves."" Di comparison between a younger Oga Museveni - wey dey charismatic, energetic and inspiring - wit today's Bobi Wine dey hard to escape. Di rebel commander be just 41 years old wen he seize power, dey promise Ugandans security, stronger economy and beta future. Some dey wonder whether im new challenger full of idealism and populist rhetoric fit make di same mistakes. Activist Siperia Mollie Saasirabo, 24, wey tok say she don dey ""political exile"" for Kenya, no to believe in Bobi Wine. For 2019, she become di face of student protests ova increase in school fees for Makerere University. For dat, dem abduct, beat and leave her barely conscious. At di end of dat year, she briefly join Bobi Wine party but later comot as she see say di party no get solid ideaology. ""Dem ask am about im economic system wen he boecome president,"" she tok, referring to one July 2020 interview Bobi Wine give to one local radio station. ""Dem ask if im dey on di left or right of di ideological setting, and im ansa na say im no dey for either right or di left and im go just use wetin go works and dis no make sense for me."" Apart from di large crowds wey gada to support him, like di one for Kanoni, e dey hard to tell how truly popular im dey and whether di cheers go turn to votes. Data on registered voters and dia voting patterns dey very limited. For dis context e get some wey don already dey question di validity of di vote. Bobi Wine, however, don encourage pipo to cast dia ballots and say make voters dey sure say rigging for polling stations no happun." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55614853 +health Coronavirus tips and tricks: BCG vaccine fit fight Covid-19? Keep calm read wetin we sabi so far One French research joinbodi, Inserm health research group don tok say plan dey to begin testing alias clinical trials of di Bacillus Calmette-Guerin special injection aka BCG vaccine as part of di fight against coronavirus for Africa. Tori be say some recent studies wey scientists for di French National Institute of Health and Medical Research -aka - Inserm do show say fewer deaths from coronavirus dey comot from kontris wey dem dey administer di BCG vaccine. BCG vaccine na special injection wey doctors dey give pikin wey dem born newly in order to protect dem for places wey tuberculosis dey common. Di Inserm group also tok say dem dey also plan clinical trial for European kontris, and in Australia and any testing for Africa go follow dis ones. Currently, no drugs dey wey fit cha cha prevent COVID-19, and even sef no vaccine. As di virus don waka across di world touch pass 0ne million pipo, scientists dey work at breakneck speed to identify ways to slow or stop di disease. Even WHO neva give anybodi go ahead or tok pim for dis BCG tori wey dey fly upandan. Well na afta two doctors for France, Jean-Paul Mira, head of intensive care at Cochin hospital for Paris, and Camille Locht, head of research for Inserm enta racism wahala with statements dem make say make dem test di vaccine as protection for coronavirus for Africa on top say di continent no get masks, treatments, resuscitation. Di statement make Africans vex sotay former footballers like Didier Drogba and Samuel Eto'o comt to tok for social media say make dem no take African pipo as human guinea pigs. Eto'o call di doctors say dem be killers. Questions still dey continue as di number of Covid-19 case for di world don clib to ova a million. WHO -World Health Organization wey be di joinbodi authority for di whole world wey go fit give green light for dis matter never tok anytin as e concern di BCG vaccine ontop coronavirus. Even oda scientists, like researchers from di Murdoch Children's Research Institute inside Australia (MCRI) wey follow wan do clinical trials wit di BCG say dem no expect di BCG vaccination to be cure or a perfect method of prevention. However, dem dey claim say di vaccine fit offer an extra round of defense if pipo fit use am alongside di protective equipment wey dem dey apply for healthcare settings. https://www.bbc.com/pidgin/world-52138929 +business Canada real estate: Trudeau propose ban for foreign buyers of real estate "Canada Prime Minister Justin Trudeau don propose to ban foreigners to fit buy houses for di kontri for di next two years. Dis na as di kontri dey try to handle some of di worst wahala of affordable housing. Prices don jump pass 20% wey push di average price of houses dem for Canada to almost C$817,000 ($650,000; £495,000), wey be nine times di amount of money di average household dey make. Oga Trudeau bin promise to handle di mata of housing affordability during im campaign for di election last year. Trudeau present dis budget proposal on Thursday and togeda wit di temporary ban for foreign buyers, di proposal wan put billions for side to ginger new construction and wan bring new programmes like tax free savings accounts for pipo wey dey buy dia first house. Di proposed ban on foreign buyers howeva no go affect permanent residents, foreign students and workers, and di pipo wey dey buy house wey dem wan live fully. Sabi pipo for di industry say e no clear weda di ban on foreign buyers go address di wahala. Di information on how many foreigners dey buy houses for Canada no dey plenti, but research say dem ammount to small fraction of di market. Ben Myers wey be di president of di advisory company, Bullpenn Research & Consulting in Toronto bin find out say foreigners na only 1% of pipo wey buy houses for 2020 wey reduce from di 9% for 2015 and 2016. Oga Myers say, ""I no tink say e go get big impact. Di pipo wey really wan buy go find way to do am"". E say di high cost of housing na sake of di rate of population growth and di shortage in supply, part of which dey because of rules wey dey reduce development. Dis issues go from bad to worse since di pandemic for 2020 wen Canada policymakers bin slash interest rates to stabilise di economy. Di policy reduce borrowing cost wey make house demand increase even more. According to OECD data, di gap between home prices and incomes for Canada na one of di most dramatic for di world." https://www.bbc.com/pidgin/world-61036116 +sports Arsene Wenger: Bayern Munich wan hold tok tok wit former Arsenal oga "Former Arsenal oga Arsene Wenger go hold tok tok wit Bayern Munich next week on top vacant manager job. 70 year old Wenger, tell Bein Sports say im dey plan to speak to Bayern executive board chairman Karl-Heinz Rummenigge afta di Bundesliga champions sack Niko Kovac earlier dis week. E dey come afta Rummenigge tok say Wenger ""no be pesin wey dem dey consider as coach"". ""We decide togeda say we go tok next week becos I dey inside Doha until Sunday. Dis na di true story,"" Wenger tok. ""On Wednesday afternoon, Rummenigge bin call me. I not fit ansa and by cool way I call am back. ""Him bein dey inside him car dey go for di game against Olympiakos. We tok for four to five minutes maximum and he tell me say dem don assign [Hans-Dieter] Flick to be be coach - him go manage di next two games. ""He [Rummenigge] ask me if I get interest becos dem dey look for a coach. I tell am say I no dey tink about am - it need some time to have a think about it."" Wenger bin spend 22 years in charge of Arsenal, e win di Premier League three times and di FA Cup on seven occasions before e leave di Gunners at di end of di 2017-18 season. Afta 10 games of di Bundesliga campaign, Bayern carri fourth, four points behind leaders Borussia Monchengladbach, and lost 5-1 to Eintracht Frankfurt in Kovac's last match in charge. However, dem get a perfect record inside di Champions League and dia 2-0 win over Olympiakos inside Flick first game wey dey in charge for di meantime, make am dia numebr four win in four group games. For di start of October, Bayern, still managed by Kovac, thrash Tottenham 7-2 for away Champions League game in London." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50354179 +sports Francis Ngannou vs Ciryl Gane: Di Cameroonian retain im title as UFC 270 heavyweight champion Francis Ngannou remain di UFC heavyweight champion afta e defend im title against undefeated interim champion Ciryl Gane for UFC 270. Di judges declare am winner wit 48-47 48-47 and 49-46. Di game happun on Sunday 23 January 2022. Afta di fight, Nigerian and UFC champion Kamaru Usman wey follow dey Francis corner enter ring to tok say dis na di evolution of Francis fighting style as e change from power punches to technical fighter. On im victory, Francis say e know say Ciryl go dey tough and e say Ciryl try well-well, but im coach tell am to calm down. Francis add say e hurt im knee three weeks to di fight but e say e bin wan make pipo know say im don improve as a fighter dat is why e decide to go on wit am. E thank im team family and friends and acknowledge di plenti love from im kontri Cameroon. For im future, e say boxing still dey for im mind and e go do am before im retire For Ciryl, e tok say e dey disappointed wit im performance and e hope say e go improve. Ngannou, 35, na one di most powerful and dominant figures for MMA history, and e bin don win im past five fights through knockout. Gane, 31, bin hold one perfect 10-0 record wit seven consecutive wins for di UFC, even as e just turn professional for 2018. Di two fighters get history. Dem be old sparring partners, Na Ngannou former head coach Fernand Lopez train Gane. Di fight between Francis Ngannou and Ciryl Gane bin take place for di Honda Center for Anaheim, California. Ciryl wey dey blue corner don dey dance enta di octagon ring. E wear all black and dey waka small-small with smile on im face. Ciryl wey come from France hold French flag. E don pull cloth and dey collect teeth guard as referee dey check am before e enta ring. Ciryl dey known for im technical ability and fans dey wonda if e go fit stop Francis power. Ciryl no fight for most of 2020 becos of Covid19. Francis don dey waka come. E wear all black and e dey bounce to Drake's song God's plan. Francis come from Cameroon and e dey popular for im heavy punches and power. E don pull cloth and referee dey check am before im enta ring. Nigerian and UFC champion Kamaru dey Francis corner. E follow am waka come ring. Dis na UFC heavyweight fight and both men don ready for dis morning main event. Referee for dis fight na Herb Dean. Ciryl na interim UFC champion and e carry im belt come. Francis na defending UFC champion. Francis sef carry belt come. Na five rounds we dey go. Fight don start. Francis throw two body shots. We still dey round 1. E remain 2 mins 30 secs. Ciryl don throw kick wey land. Ciryl dey move well well. Francis dey try knock am out with im shot. Both men don lock for corner but Francis throw knee. Ciryl sef land knee. Ciryl land kick. 10 secs remain. Round one don end. Francis team dey ask am to change in technique and give straight blow and upper cut. Round two don start. Ciryl land kick for Francis belle. Ciryl dey kick Francis left leg. Ciryl land jab for Francis head. Francis no dey move, Ciryl don land anoda kick. Francis don land kick for Ciryl body. Francis land blow for Ciryl head. 10 secs remain. Round two don finish. No action for dis round. Ciryl coach tell am make e dey hit Francis with im legs and make im drink water. Dem also tell am make e continue dey move well well around di ring. Round three don start. Francis don slam am o. Francis hold am for ground Francis pin Ciryl. Francis lock am well. But Ciryl don stand up. Francis don give am judo throw. Dey still dey locked. Dem dey locked inside corner. Ciryl don use spinning elbow comot di lock. Francis don land Ciryl for ground again. 10 secs remain for dis round. Dis round don finish. Francis team say make im continue dey find upper cut and straight blow. E be like say Francis don dey tire and Ciryl still dey move well. Ciryl land jab. Ciryl give spinning turn kick to Francis belle. Francis don hold Ciryl for corner. Francis don land am for ground for di third time. Francis pin am for centre of ring. Francis don land am for ground again. One min remain for round four. Francis land knee for Ciryl chest. Francis pin am for ground. 10 secs remain. Round Four don finish. Na di decider be dis. Ciryl don start with di kicks again. E dey kick Francis leg. Ciryl land good combination. Two punches e land for Francis face. Ciryl don make mistake. Francis don turn am. Ciryl manage lock Francis leg. Francis don free im leg. Francis dey on top am. And e remain one min 34 secs. Francis lock am for centre of ring. But e be like say Francis don tire. Francis dey on top am and e remain 10 secs. Fight don finish. Both men look tired well-well. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60097466 +politics Kellyanne Conway, Sarah Huckabee, Steve Bannon, Sean Spicer and odas wey resign, chop sack under Trump for White House "Kellyanne Conway don announce say she dey resign from her post as Senior Counsel to US President Donald Trump. Inside one statement, Mrs Conway say she dey step down by di end of August to focus on her children, to give dem ""less drama, more mama"". Her husband George, wey be also pesin wey dey also criticise di president, go also step back from political activism. She add for her statement say her decision na ""completely my choice,"" and say she go announce her future plans ""in time"". Di Republican strategist and veteran pollster, don serve for four years, dis one make her di highest-ranking woman for di White House. She be also di first woman to lead successful US presidential campaign, she contribute for Mr Trump successful effort for 2016. Mrs Conway say her time for di White House come with blessings wey she no fit compare As Senior Counsellor for di White House, Mrs Conway act as political advisor to President Trump and maintain ogbonge position for di administration. Di past four years don give me blessings beyond compare,"" she tok inside statement. ""[George and I] dey disagree about plenty but we dey united on wetin matter di most: di kids,"" she tok. ""Our four children are teens and tweens wey dey start new academic year, dey middle school and high school, remotely from di house for at least a few months,"" Mrs Conway tok. ""As millions of parents nationwide know, kids wey dey 'do school from home' require one kain level of attention and vigilance wey dey as unusual as dis times."" Di announcement dey comes hours afta Mrs Conway daughters, Claudia, tweet say her mama job don ""ruin [her] life"" - message wey later go viral. Mrs Conway na one of President Trump strong supporters, but na controversial figure for long time. She no be di first pesin to resign or chop sack for Trump administration. Steve Bannon bin work as Chief Strategist for di Trump Campaign and dem fire am for August 18, 2017. Di sack come afta Trump comment on di Charlottesville riots. Dem recently arrest Steve Bannon say im bin get hand for wuruwuru wey happun to di money dem get from charity for di purpose to to build Donald Trump wall. Hope Hicks bin work as di White House fourth director of strategic communications. Madam Hicks spend three years with Trump for in campaign and presidency. She resign one day afta she tell congress say she bin don tell ""white lies"" for her oga. Tori be say afta she comot White House, she start to dey work as chief communications officer for Fox Corporation. Jeff Sessions bin work with di Trump Administration as di Attorney General. Afta one year nine months with Donald Trump, Sessions comot afta Trump start to dey give am heat on top say im wash hand comot di investigation on top weda Russia bin get hand for Trump campaign. Sarah Sanders serve for di office of di Press Secretary afta Sean Spicer bin comot. She work for di Trump administration for almost two years. Although e no clear why she resign, for her time as press secretary, accusations bin dey say she bin dey lie to reporters. As at now, she be contributor for Fox News and dey active for conservative groups. Sean Spicer bin start off for di Trump administration as Press Secretary, e comot office afta only six months afta dem hire oga Scaramucci to do di work we already dey do. Spicer currently dey work for di Navy, e be published author and comot as contestant for di TV show, Dancing With The Stars." https://www.bbc.com/pidgin/world-53886106 +sports Coronavirus: Anthony Joshua vs Kubrat Pulev 20 June fight don march break till further notice British-Nigeria heavyweight, Anthony Joshua fight against Bulgaria Kubrat Pulev to defend im IBF, WBA, WBO and IBO world titles don march break till further notice. Di fight bin suppose hold for Tottenham Hotspur Stadium on Saturday, 20 June. Dem bin postpone di fight on top di coronavirus palava for world. Dis dey come from statement from Joshua promoter Matchroom Boxing wey tok say dem dey work on new date for di fight. Joshua neva fight since December wen im win di fight against Andy Ruiz Jr for Saudi Arabia to collect back im belts wey di Mexican-American bin collect for New York wen dem first fight for June 2019. Pulev na compulsory fight for Joshua IBF belt. Im bin suppose fight Joshua for October 2017 but n fit do am because of sholder injury. Di British Boxing Board of Control bin suspend all di fights under them until di end of May ontop di coronavirus. https://www.bbc.com/pidgin/sport-52160951 +entertainment Tega and Boma: BBNaija housemates 'alleged' kissing video, relationship plus how pipo react "Big brother Naija housemates Boma and Tega don become close for di big brother 'shine ya eye reality show sotey dis don tok-tok for social media. Tega wey come from Akwa Ibom state na married woman wey bin introduce herself as pesin wey get personality of water and fire. While Boma wey be 34-years-old mixologist, model and former footballer too bin don marry before. Early on for di show, Tega begin make pipo notice her afta one truth or dare game wey she allow fellow housemate Saga to see and 'suck' her nipple. Recently, na her closeness for di house with fellow housemate Boma, especially becos of marital status dey make both of dem trend. Dis week, one video begin trend online wey show Boma and Tega dem ontop bed dey kiss. Di video go viral and spark a lot of reactions. Inside di video, Boma and Tega sleep ontop bed. Dem near each oda before dem bin kiss. While some Nigerians believe say dis one no suppose be sake of her status, odas say she just dey catch cruise and play her game. Di first time Tega begin trend say she allow anoda man 'see' her breast for di show, her husband bin come out to defend her. Tega husband bin post ontop im Instagram page @ajmoney001 where e ask di viewers ""to stay tuned for more content"" as e add say im wife na actress. According to am, Tega go still do more for di house. Im post read: ""My wife na actress. If dat na movie scene, she go still do more. On Tuesday, afta video of Tega and Boma kiss bin go viral, reports say her husband post some messages again ontop Instagram. ""First of all, I love my wife so much. However, I go like to state say our marriage no dey perfect just like many oda marriages out there. We be two imperfect pipo. Di past 24 hours don be hell for us as a family,"" Tega husband took. ""I don wrong my wife in so many ways but cheating on her na wetin break di bond wey we get as a couple. Before you judge me, please note say I no dey perfect. I no be di best husband as you all tink I dey."" I bin cheat on my wife in our matrimonial home. I no dey proud of dis. Dis mistake don cause so much damage in our marriage to di extent of her threatening to leave our once happy home. ""In my own little way, I don try to make amends for everything I don do wrong. I don try to support her dreams, to campaign and defend her and also to be a better man. But all these, I do am in her absence. 'She no deserve me. She deserve her happiness and peace of mind. And if she dey do or saying anything to spite me, na because I deserve am."" ""I dey sorry babe for not being di man you want me to be for you. I dey sorry for everything. I be just a man wey don make mistake and hope you forgive me. I love my wife and go give her all di support she need."" ""Even if she no forgive me, I want di best for her because she don be nothing but di best woman for my life. God bless you all for your prayers and support."" Di message bin read. As at di time of filing dis report, dat message don delete. Meanwhile, On Tuesday, report come out say Boma open up about how e feel about Tega during di live show. During im conversation with Jaypaul, e confess say e like Tega and e also tok about some of her virtues, and how like-minded two of dem be." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58407313 +entertainment BBNaija new Head of House: Jackie B, Jaypaul be HoH for Shine Ya Eyes Big Brother House Big Brother Naija housemates Jakie B and Jaypaul don become new Head of House [HoH] for di TV reality show. Di two beat oda housemates on Monday to find di most keys and finish dia task for di weekly game on 30 August. Jackie B and Jaypaul na di number six and 7seven pesins to sit for di Head of House. Di Head of House throne come wit immunity from eviction package for di week plus oda benefit. Di housemates wey don since enjoy di privilege na Peace, Boma, Pere, Maria and Liquorose. Dis week HOH game bin come wit a twist as Biggie announce earlier say dem go get two winners. E no dey clear why but to every game na im unexpected features wey dey make am dey interesting. Biggie call di new twist 'The double heads of House'. And e tok say di rest of di house go get nomination and therefore go dey up for eviction. So far, out of di 26 housemates wey start di reality show some weeks ago, 9 of dem don carry dia load comot from di house. Only one pesin go dey eligible to go home wit di 90million overall winner price. Na Queen be di first housemates to find more than one key during di game. Boma become di first male housemates to finish di challenge. But later Jaypaul overtake Boma to gbab di fastest time for di challenge. Tega follow Boma for back to become di first female to complete di challenge. Jackie B also break record to find di keys and still get di fastest time so far among di ladies. Michael bin search but im no find any of di keys. No be only Michael, Cross also enta di game and comot without any key. Yousef bin dey inside di pool wen time run against am. Whitemoney find just one key https://www.bbc.com/pidgin/tori-58387343 +business Forbes African of the year: Ghana Nana Akufo-Addo host Cyril Ramaphosa of South Africa in Ghana "Prez of South Africa, Cyril Ramaphosa dey Ghana on a two day working visit which go end Sunday 5 December, 2021. Reason for en visit be say he wan deepen bilateral co-operation den ties of friendship between Ghana den South Africa. Ghanaian leader, Nana Akufo-Addo share photos of de two when he receive de South African leader for Jubilee House. As part of en two day work visit, Prez Ramaphosa visit Ashanti Region. Ramaphosa witness de display of rich Ghanaian culture during de 50th Anniversary celebration of Juabenhene. During dis cultural trip, he dey in de company of Prez Akufo-Addo who show am around. According to Prez Akufo-Addo, ""cultural exchanges between Ghana den South Africa...go fit strengthen de relations."" ""We repeat our firm opposition to all attempts to single out African kontris for di imposition of travel bans, as instruments of immigration control. ""When we dey hear, for example, say di omicron variant of COVID-19, wey dem bin recently sequenced and reported by South African scientists, naw way earlier for Netherlands dem discover am"". Dis be de words of President Nana Addo Dankwa Akufo-Addo of Ghana, when he addressed a joint press conference at Jubilee House, with the President Cyril Ramaphosa of South Africa. Di President comments follows di decision by di US, UK and EU to bar entry to travellers from South Africa, Botswana, Zimbabwe, Namibia, Lesotho, Eswatini, Egypt, Mozambique, Malawi and Nigeria. De travel restrictions follow de discovery of the Omicron variant of COVID-19. Di tok-tok also centered on driving investment opportunities, domestic and foreign, into both kontries. Dem alos dwell on realization of 17 SDGs, and de need for enhanced co-operation and partnership in de areas of education, trade and industry, agriculture, defence co-operation. Also for immigration, environment, science and technology, petroleum and hydrocarbon activities, and tourism. President Akufo-Addo thank President Ramaphosa and South Africa for supporting Ghana bid for de Secretariat of de African Continental Free Trade Area (AfCFTA), and for a non-permanent seat at the United Nations Security Council, He say ""Ghana go make sure dat Africa voice dey heard loud and clear in de deliberations of de Security Council. ""Both on matters affecting the continent and on global issues, and we will consult broadly to define Africa's interests"". De Ghanaian leader add. Dis visit coincide wit wen FORBES AFRICA name President Akufo-Addo as African Of The Year. Inside dia December 2021-January 2022 edition, de magazine feature Ghana President, naming him African Of The Year. Priding itself as Africa's Most Influential Business Magazine, FORBES AFRICA don dey in existence for de past ten years and gain prestige across de continent and beyond. FORBES AFRICA post de front cover of de magazine on dia official Twitter page with a photo of the smiley President embossed on it. According to de Magazine, what earn President Akufo-Addo dis enviable recognition be say he dey ""focused on a new paradigm of economic growth in Africa""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59537657 +sports 2023 Women World Cup: Why Brazil comot hand for di tournament bid Brazil don pull out from di running to host di 2023 Women World Cup. Di Brazilian Football Confederation (CBF) say goment no tink say na wise decision to put money for di sport as coronavirus pandemic still dey. Brazil don give dia support to Colombia wey get interest against Japan and kontris like Australia and New Zealand wey wan joinbodi host di 32-team tournament. Fifa go vote to choose di hosts for June 25. For inside statement, di CBF tok say because of di hardship wey Covid- 19 cause dia economy, dem don comot hand for di competition. Brazil don host plenty major international sporting competitions wey include di Men World Cup for 2014, di 2016 Olympic and Paralympic games and the Copa America for 2019. Di Covid-19 pandemic bin affect di kontri badly, wit more than 35,000 deaths and 640,000 confirmed infections, but pipo wey die pass dis figure sake of testing materials wey no too dey. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52982269 +sports Ghana Black Stars final 26-man squad for Qatar 2022 "Ghana national team coach, Otto Addo don announce en squad for de Qatar 2022 Fifa World Cup tournament. De final list feature 26 players who go represent de West African nation in de global football tournament. De players wey make de final selection be dis: Manaf Nurudeen Danlad Ibrahim Lawrence Ati Zigi Tariq Lamptey Alidu Seidu Daniel Amartey Joseph Aidoo Alexander Dziku Mohammed Salisu Baba Rahman Gideon Mensah Andre Ayew Thomas Partey Elisha Owusu Salis Abdul Samed Mohammed Kudus Daniel Kofi Kyere Daniel Barnie Afriyie Kamal Sowah Abdul Fatawu Osman Bukari Inaki Williams Antionne Semenyo Jordan Ayew Kamaldeen Sulemana Dennis Odoi De Black Stars go face Portugal, South Korea den Uruguay in Group H of de competition during group stages. Although dem dey enta de tournament as one of de least favorites, de fans dey hope say de Black Stars go pull surprise in de tournament. Ghana dey hope say dem go rely on de new additions to de national team to enrich dia side. Star players like Inaki Williams wey dey play for Atletic Bilbao dey in de final squad, Brighton Holve and Albion star, Tariq Lamptey switch from England to represent Ghana. Oda strong players in de EPL like midfielder Thomas Partey, defender Mohammed Salisu, fast rising star for Ajax, Mohammed Kudus who get world class quality all dey in de Ghanaian side. Top Atletico Bilbao striker, Inaki Williams en decision to represent Ghana excite more football fans de de country. He make de announcement on en Twitter page afta months of speculation which dey link de player to Ghana ahead of de 2022 Fifa World Cup. Coach Otto Addo out am inside en final squad for de tournament to help strengthen de striking department of de team. Inaki Williams get en first international call up to represent Spain under-21 squad in March 2015. Despite playing for Spain junior national team, he no make major competitive appearances in dia national team side. In 2021 wen dem ask am about de possibility of playing for Ghana he talk say “my parents dey come from Accra, dem no born or raise me there, my culture dey here. ”But on July 5, 2022 he make u-turn on en decision to represent Ghana by wearing de Black Stars ahead of de 2022 Fifa World Cup. “De moment come for me to find my origin within myself with Africa den Ghana” Inaki talk inside video. Latest person to join de Black Stars be former English player, Tariq Lamptey. Taking to de social media handles, Black Stars announce say de player make de switch from England. “E be just a matter of time...Welcome home Tariq” Black Stars social media handle talk. Tariq Lamptey visit Ghana wit en family after de end of de 2021 English Premier League. He talk to local media say he dey Ghana for ""some sun and family time."" Coach Otto Addo name am inside en final squad list so say he go give de team speed on de wings where he dey play." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c9xp4w98rzzo +politics Ekiti governorship election 2022: Candidates tok wetin dia plans be for di state "Security and unemployment dey among di mata wey lead tok tok during di Ekiti state governorship election debate wey BBC Yoruba organise for candidates wey wan contest for govnor office in di state. Candidates wey dey contest for govnor seat across parties for di state election wey dey come tanda for front of di state pipo to tok about di plans wey dem get for dem if dem win di election. Youth Progressives Party (YPP) candidate for governor, Debo Ranti Ajayi na im first ginger di tok tok wen im say im get di secret of how Dubai become popular, and Ekiti state go be like Dubai within four years. E say di thing wey surprise am be say, di current crisis for Ekiti be lack of moni and if anybody say dem go rebuild di city wit only money from Abuja, na lie e add. ""I be di only one wey fit pay di staff of Ekiti State."" For im speech, Segun Oni today from the Social Democratic Party, SDP said the things he had done during his tenure would continue to be about education and health care. Di only female wey dey among di candidates, Kemi Elebute-Halle of ADP say di party get three steps to take so dem go fit strengthen democratic goment for di pipo Elebute-Halle say pipo wey bin dey goment bifo no do well, and now be time if dem allow to take over Ekiti state goment. ""On security agenda, we get three principles for security mata. We go provide work for young pipo to reduce di challenge of security, i go provide public awareness programs, and work wit security pipo."" ""I don dey take care of pipo wit special needs bifo I contest. For Debo Ranti Ajayi, e say im get di secret of how Dubai become popular, and Ekiti state go be like Dubai within four years. E say di thing wey surprise am be say, di current crisis for Ekiti be lack of moni and if anybody say dem go rebuild di city wit only money from Abuja, na lie e add. ""I be di only one wey fit pay di staff of Ekiti State."" Debo Ajayi add say bifo di end of four years, Google and Microsoft go land for Ekiti state and Ekiti state go be reborn. For im own speech, Segun Oni of di Social Democratic Party, SDP say di tins e don do during im tenure go continue about education and health care. Oga Oni say im no fit say im no do well wen im rule, but im fit do more dan dat. Especially for di health care sector. Wen im go tok, Oluwole Oluyede of ADC political party, say e get knowledge and dey committed to rebuild Ekiti state as health sabi pesin. Oluyede tok say for health sector, moni dey important and im goment go work wit di private sector to reform Ekiti state health system. For security mata, e sa if job dey for young pio, greed to steal no go dey. ""We go re-establish vigilante, Autonomy go dey for local goments, we go establish state police and provide modern technology for security pipo."" For di same way, for di pipo wit special needs, im government go do wetin dem need for dem, im go invest through borrow scheme wey dey easy , and goment jobs go dey for dem. Candidates of di Peoples Democratic Party, PDP, Bisi Kolawole, say im own focus be Agriculture, health, women advancement, and economic development be key areas of im goment. Kolawole say on security mata, e get plan to make sure say vigilantes work wit law enforcement pipo to stop security gbege. ""We don do am bifo, we go do am again if we enter."" Citizens from different parts of di state bin dey invited to attend and to participate for di event. Di candidate of di All Progressives Congress APC Biodun Oyebanji no show face for di debate." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61582037 +health Madagascar coronavirus cure: African kontris wey don receive covid-organics tonic "Even though say World Health Organization never give green light to di 'miracle herbal drink' wey Madagascar president say dey work against coronavirus, some African kontris don begin receive di drug. Wit steady increase in cases of Covid-19 inside Africa, different kontris don begin turn to di drink wit hope say e go be di ansa to virus. On May 13, Comoros president, Azali Assoumani tell di pipo of Madagascar 'thank you' afta di kontri receive donation of di Covid-organics from Madagascar. Delegation from Comoros bin fly go Madagascar to collect di consignment weeks after dem bin signal interest to get di drink. Nigeria say dem dey expect di Madagascar Covid-Organic herbal medicine even though di goment also make am clear say di kontri go submit di drug to standard pharmaceutical tests. At di time of dis tori, BBC Pidgin no go fit independently verify how well dis drink dey helep dis african kontries wey don collect di drink dey use. Launched as Covid-Organics, dem produce di drink from di Artemisia plant - di source of ingredient wey dem dey use for malaria treatment and oda Malagasy plants. Dem dey market am inside bottle and as herbal tea afta dem test am on less than 20 pipo over period of three weeks, na so di president chief of staff tell BBC. Di Malagasy Institute of Applied Reseach (Imra) don ""test am for two pipo and e don cure dia treatment"", according to president Rajoelina. Im add say ""dis herbal tea dey give results in seven days"". Oga Rajoelina say di kontri dey work wit foreign researchers to create di drink as injections. Di World Health Organization, don draw eardrop warning ontop dia website say ""no evidence dey to suggest say dem fit avoid COVID-19 or treat am wit products wey dem make from from Artemisia-based plant material."" However Madagascar President Rajoelina don continue to defend dis ogbonge COVID Organics against pipo wey dey bad mouth am. Inside one interview with French radio stations on Monday, im say di world just no want to admit say ""a kontri like Madagascar fit develop dis formula to save di world"" from COVID-19 Coronavirus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52681595 +health Measles outbreak in Cameroon: Why di disease dey spread for di country Cases for measles don reach 1300 for 78 districts for Cameroon and plenti popi di wanda why dis sick di spread for kontri Measles na sick weh e fit komot from pesin to anoda and na virus di cause am. De signs na fever and small-small pimples for skin -coro-coro wit catarrh for nose. Just now, measles don spread for eight of de ten regions, 13 pipo don die. Only two regions Northwest and Southwest nova get dis new outbreak. Mostly na pikin dem from 9-59 moon catch measles and plenti of dem no bi don go for vaccination. De reasons weh de cases di increase as Expanded Programme on Immunisation, PEV, tok: Cameroon di get supplies from Europe and Asia but because deh lock factories for three moons deh no respect de time table, PEV write. For December 2019, goment add second vaccine for measles and insid four days deh bin chuck injection for more dan 3 million pikin dem Goment di put more force for sensitise pipo for take dia pikin dem for vaccination especially as e concern measles. Health officials say hospitals bi safe for vaccinate pikin dem as special centre di take care of Covid-19. No bi only measles di spread for Cameroon for dis taim weh kontri dis also struggle for reduce spread for Covid-19. Cholera, sick weh e kam wit running stomach, also di worry pipo for seaport town of Kribi for de past one moon. Just now, 42 cases for cholera dey, 20 Cameroon and 9 Nigerian fishermen dey among de sick pipo and four pipo don die. Cholera na sick weh e dey laik came no go. Places for far North, Southwest, Littoral and centre region don register about 2302 cases between 2018 and 2019. For Kribi, one of de areas weh Cholera di spread, local health authorities di tok for pipo say dey get for di use toilet no poo for open air as e di helep for spread Cholera. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53310816 +sports Man United vs Villarreal: Champions League predictions, time & how to watch Manchester United go dey without dia captain Harry Maguire for dia Wednesday Champions League match against Villarreal. Luke Shaw na anoda player wey fit no play dat game for Old Trafford sake of injury. Dia defender Aaron Wan-Bissaka dey suspended, and striker Marcus Rashford still no dey fit to play. No be only Manchester United get injury palava, dia opponent Villarreal get dia own too. Di Spanish team say dia striker Gerard Moreno is set to miss out with a muscle injury, and Francis Coquelin dey suspended. For match day one, Manchester United bin lose 2-1 to Young Boys while Villarreal play 2-2 draw wit Atalanta. As tins be now, na Young Boys dey top Group F wit three points followed by Atalanta and Villarreal wey get one point each and Man United dey bottom of di group wit zero point. Manchester United dey come into dis match wit so much pain, sake of dia defeat against Young Boys, West Ham, and Aston Villa. Add last season Europa League loss to Villarreal, dia opponents here, I dey see a vey angry Red Devil. Na wetin football sabi pesin Deji Faremi tell BBC Pidgin. Villarreal go try to hold on. And wit six draws in seven games dis season, e dey look like dia game plan go be to play for draw again. But I feel say dia plan no go work because United go play dis match wit plenty ginger. Manchester United 4-1 Villarreal. Wednesday match go dey live for SuperSport and di coverage go start at 7pm while kick-off na 8pm West African time. Man. United: De Gea; Dalot, Varane, Lindelöf, Alex Telles; Fred, McTominay; Pogba, Bruno Fernandes, Greenwood; Ronaldo Out: Wan-Bissaka (chop suspensions), Rashford (shoulder injury), Diallo (thigh injury), Maguire (calf injury) Doubtful: Shaw (hamstring) Villarreal: Rulli; Foyth, Albiol, Torres, Alberto Moreno; Trigueros, Capoue, Parejo; Pino, Alcácer, Danjuma Out: Gerard Moreno (hamstring injury) Doubtful: Raba (ankle injury), Chukwueze (hamstring injury) Ronaldo fit break Iker Casillas all-time Uefa Champions League appearances record on Wednesday, wen United host Villarreal. Villarreal bin beat di Red Devils for last season Uefa Europa League final. Ronaldo wey be 36-years bin equal Casillas 177 appearances for Match day 1. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58736253 +entertainment Ada Jesus dead: Nigerian Comedian, Ada Jesus don die afta battle wit Kidney disease "Popular Nigerian Comedian, Ada Jesus don die. Harrison Gwamnishu wey be di man wey dey lead di group of Nigerians wey cari Ada Jesus go hospital confam di news of her death to BBC Pidgin dis afternoon. ""She don go"", im tok. Di Nigerian comedian Ada Jesus wey her real name be Mmesoma Mercy Obi for interview wit BBC Igbo bin tok say she dey sick wit kidney problem. For interview wey she do for February 2021, di Instagram sensation bin say e don reach almost one year wey she don dey battle di illness. ""Since December, my bodi dey swell up especially my belle and my face. I no dey fit waka because I no even get strength to stand up. ""Wen I go hospital dem tell me say wetin dey worry me na kidney problem say if money dey, dem suppose carry me go India go do transplant."" Ada Jesus reveal say a lot of pipo don make donations and as at dat time, e remain small make di money reach for her to travel for di transplant. On April 19, Video bin surface on social media as a group of pipo gather for hospital wia dem dey treat Ada Jesus to celebrate her birthday. Before then reports bin comot say she bin don dey get better" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56833472 +entertainment Ada Jesus: See wetin Prophet Odumeje tok about di comedian sickness "Chi Marine Temple one so called witch doctor tok say im don forgive Mmesoma Obi wey pipo know as Ada Jesus. ""Ada Jesus bin disrespect me,"" na wetin Chi Marine Temple tok. Di so called witch doctor say im see how Ada Jesus dey helpless for ground - na why im dey follow beg Prophet Chukwuemeka Odumeje wey Ada accuse say im dey do fake miracles to forgive her as im don do. Chi Marine Temple say if im fit forgive Ada Jesus regardless of di insults she pour for im body (di insults wey even pass everybody own), im expect say Odumeje wey be Christian suppose do di same. Chi Marine Temple later dash her money make she add join odas wey pipo don give am to go hospital. Tori be say Ada Jesus wey be comedian dey sick wit kidney problem. All dis tins wey dey happen come make pipo dey tok say Ada Jesus dey helpless wit di sickness because of di insults and di disrespect wey she give Chi Marine Temple, Rita Edochie wey dey act movies for Nollywood and Prophet Chukwuemeka Ohanaemere wey pipo know as, Odumeje. For video wey go viral for social media Rita Edochie wey dey act movies and Prophet Odumeje tok say dem no go ever forgive Ada Jesus because of di kain tins wey she tok about dem.Dis na afta Ada Jesus father carry di comedian go di Prophet church to ask for forgiveness and pray for her healing - but Odumeje just dey go round di woman wey dey for ground and tok say ""I'm no go forgive am.,"" ""Nobody dey tok about me and dey go free,"" na wetin Odumeje tokDi Prophet tok say Ada Jesus make pipo wey dey for Facebook dey call am fake prophet say im miracles dey fake. Meanwhile Madam Edochie tok for inside di social media video say Ada Jesus insult her and her family, She challenge Ada Jesus to produce one person wey she don bring for fake miracle and if she no bring di pipo she no go fit stand up. But for anoda video wey she post di Nollywood actress say she receive calls from alot of pipo all ova di world wey ask her to forgive Ada Jesus. She say ""I dey here to tell all of una say I don forgive Ada Jesus, from my heart of hearts Ada Jesus I don forgive you"". But she also warn oda pipo make dem stop to insult men of God especially her man of God." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56714242 +entertainment "BBNaija Kiddwaya papa ""Terry Waya"" say na im discover Banana Island Lagos" Many pipo know Terry Waya as Nigerian socialite and billionaire wey sabi throw expensive party to jollificate. But no be everibodi know say na im discover and get di contract to develop di luxury Banana Island for Lagos, Nigeria commercial capital. Banana Island na man-made Island wey cover close to 1,630,000 square metres and dem divide am into 536 plots. Na Lebanese-Nigerian Chagoury Group join bodi alias partner di Federal Ministry of Works and Housing to construct am. Oga Terry Waya claim say na im dem give di job to develop di area before e hand over to Chagoury to do di job. Oga Terry reveal dis one wen e dey tell BBC Pidgin News how e take make im money as a young man for Nigeria. E explain give say nobodi bin know about Banana Island before and dat one day im bin go visit one of im tight friends, General Adisa wey be minister of works den. As e land di office, e come see one big poster for im back wey dem write -Banana Island. Im come ask im friend, wetin di poster mean, di general come explain give Terry Waya say dem dey look for partner wey dem go join bodi take develop di Banana Island and then sell am. Di partner go get im share and di goment go take im own share. Oga Terry add. Becos of im friendship wit Adisa, e come ask am make im give am di job to do and true-true e come give am di project. Terry Waya na come decide to call Chagoury to do di project and dis na how dem give birth to di ogbonge Banana Island. Terry Waya na BBNaija Kiddwaya billionaire papa wey also be London-based Nigerian businessman. Oga Waya age 55 bin reportedly face some kain case for British court between 2006 and 2008. Terry Waya na native of Tiv for Benue State middle belt Nigeria. Di Nigerian socialite love Versace fashion wella. https://www.bbc.com/pidgin/54173142 +sports UFC 245: Kamaru Usman fight with Colby Covington wetin you need to know "Nigeria Welterweight champion Kamaru Usman, go fight Colby Covington for UFC 245 inside octagon for Las Vegas, United States on Saturday night. Tori be say na three title fights go happun but na Kamuru fight na im be di main event of di night, sake of say di two fighters don dey eye each oda since. UFC na di biggest competition for MMA, wia di fighters dey combine boxing, kickboxing, jiu-jitsu, wrestling and every- every wen dem dey fight. Kamaru Usman na di first African fighter to win Ultimate Fighting Championship title. Di Nigerian neva lose for im last 14 fights for UFC. Im record na 15-1. Usman get six career knockout win and one submission victory. Dis na wetin Usman tok about di fight: Im say ""If you want to be champ, you go show up for di champ open workout and try to distract dem, right? Why you show up for my own? Because im know say e go happun. ""Im know say I be di most dangerous guy for di division and im know bin want fight. So im don dey show imself no be today. ""I dey relaxed becos I know wetin I go do."" Colby Covington na former interim champion. Im record na 15-1. Covington get four career win by submission and three knockout victory. Di American neva lose for im last seven fight. Dis na wetin Covington tok before di fight : ""All di tins I dey tok na true, and if pipo dey feel one kind dis no be di (Ultimate) Feelings Championship na di (Ultimate) Fighting Championship, so I go do anytin to take sell di fight na wetin I gatz do. ""I dey real. Plenti fighters dey fear to fall .Me I know dey fear to fall becos I know say I be winner and I go continue to win."" Tori be say Usman and Covington go make $500,000 each for dis dia fight." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50793509 +politics I stand for peace election 2020: Stonebwoy peace walk concert for Ghana election on 7 December - Foto """I stand for peace election 2020"" train of [Ghana Election 2020] stop over for musician Stonebwoy town of Ashaimana, Accra on Saturday. Stonebwoy dey do peace walk for Ashaimana ahead of di national elections wey go happun for 7 December, 2020. Di event na to bring all political parties together to join waka for peace. On dis day all political parties walk as one to uphold Ghana democracy. Di dancehall king say Ghana need peace for di upcoming election and di best thing to do na to to bring parties together." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55112942 +entertainment BBNaija 2021: Pere and Maria na di 'wild cards' for Big Brother Naija season 6 "Big Brother don reveal di identity of di two wildcards of season six for di reality television show. Di wildcards na Pere and Maria and na during di diary session Biggie reveal am to di viewers Di wildcard na new twist wey Big Brother introduce dis season for di show wey start on Saturday July 24, 2021. Na 22 housemates enta Biggie house dis season. Tori be say Biggie give di house di task to discover who dis two housemates be and so far everybody don turn detective ontop di matter including di fans too. According to Biggie, di wildcards na fake housemates wey im put for di Shine Ya Eye House. As Housemates still dey scratch dia head to find out who di two wildcards be for Big Brother season six. Biggie don end detective work for di viewers as im reveal Pere aand Maria as di fake housemates dis season. Earlier Biggie bin drop strong clues during di housemates diary session on Thursday. For Emmanuel diary session na im Biggie drop di first clue about di wildcards for di house. ""Take good note of how di housemates dey enta di diary room, for dia diary session today di wildcard dey come in one afta di oda."" Biggie tok. Di second clue Biggie drop na say ""Di wildcard know say dem be di wildcard."" Biggie tell anoda housemate Tega Dis week, di Housemates get di task to find out who di wildcards be - and if dem guess correctly, these wildcards go dey evicted. But, if dem fail to fish out di right Wildcards amongst dem, di Wildcards go remain for di game and go compete for di grand prize. Dat no be all about di twist, if di wildcards no dey evicted on Sunday, dem go get exclusive power to nominate on Monday. BBNaija na di biggest reality show for Africa, ova 49 kontries for di continent tune in to watch di season launch according to di organizers. Dis season housemates dey compete for di grand prize of N90million naira worth of prizes, wey be di biggest reward since di show start." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58019072 +sports Anthony Joshua vs Andy Ruiz time: See Joshua 'brutal plan' for Ruiz Jr "Nigerian born British boxer Anthony Joshua go meet Andy Ruiz Jr inside Saudi Arabia on Saturday night for fight wey go decide im career for di World Heavy Weight Boxing Championship. Di big fight wey evri dey wait for dem title am unification rematch, and e go takes place on Dec. 7 for Diriyah Arena - custom-built 15,000-seater venue inside Diriyah, Saudi Arabia. Di fight go happun from 8:30 PM Nigerian Time on Saturday. Joshua lost im world heavyweight titles to Ruiz jr wen dem first fight for New York on 1 June, 2019. ""I dey here to win, I no get fear for mind..., I don say my prayers and take time to embrace wetin go happun on for Saturday"" Na wetin Joshua tok. ""I love dis belts, dia is no way me I go let dis belt dem go... I know say im lost weight... I ready for watever go come my way... Saudi Arabia na special place wia I go make history"" Na wetin Ruiz Jr tok. Joshua - Ruiz Jr Nationality: British - American/Mexican Age: 30 - 30 Height: 6ft 6 - 6ft 2 Stance: Orthodox - Orthodox Reach: 82 in - 74 in Record: 22-1-0 - 33-1-0 KOs: 21 - 22 Rounds: 91 - 151 Debut: 5/10/2013 - 28/03/2009 Nickname: AJ - Destroyer Tori be say Joshua dey set for one of di biggest ever paydays in boxing history. You fit watch di match here: Na Sky Sports and DAZN USA be di major tori pipo wey go show di fight." https://www.bbc.com/pidgin/sport-50617663 +sports Gernot Rohr: Nigeria Football Federation neva sack Super Eagles coach "Nigeria Football Federation say truth no dey inside tori wey say dem don sack dia coach, Gernot Rohr. For inside statement wey di NFF release, President of di association Amaju Pinnick say ""dem never take decision to sack Rohr"". Pinnick add say di NFF board dey study report of di Technical Committee afta dia match against Cape Verde on Tuesday for Lagos. Im add say possibilities to sack am dey but as e be now, im never chop sack. Gernot Rohr wey become di Head Coach of di Super Eagles for August 9, 2016 don already spend five years for di position since NFF President Amaju Pinnick hire am. Even though im contract suppose end for 2022, Nigerians wey like football well well don dey call for im sack. Since 2016 wey Rohr start to coach di Super Eagles, some Nigerians don argue say dem neva see di beta impact wey him don make for di team. As di ongoing 2022 FIFA World Cup qualifier still dey continue, Nigeria still get hope to reach dia 5th World Cup. But recent results from di team don cast doubt on di coach future. Di recent 0-1 home defeat to Central Africa Republic for Nigeria backyard inside Lagos shock Nigerians well well. Nigeria manage just one win from three at home for di qualifiers as dem beat Liberia 2-0, before dat loss to Central African Republic and come end am with Tuesday uninspiring draw wit Cape Verde. ""We understand di mood of di public and our supporters, but e go dey unwise to take such drastic decision about coach,"" one top Nigeria Football Federation official bin tell BBC. ""Na true say performance no dey appealing but di man never fail. Pipo need look beyond dis moment and remember say Nations Cup dey come. ""Di World Cup play-off go follow for March so wetin di coach need na our full support. We no go sack am."" As coach of Nigeria senior national football team, Gernot Rohr don play 54 matches: im win 28, draw 13 and lose 13. Even though im qualify Nigeria for di 2018 World Cup for Russia, Nigeria fail to win di 2019 Africa Cup for Nations wey hold for Egypt. Frustration still dey say na 'Golden bronze' di team, somtin wey local Nigerian coaches don achieve. Nigeria wey be kontri wey like football well well never forget di 2013 Africa Cup of Nations wey di Late Stephen Keshi win. Gernot Rohr na 68 year old Franco-German, na on June 28, 1953 naim dem born am for Mannheim inside Germany, Na bifor bifor player for di German National Team and na Defender him be. Him don play for clubs like Bayern Munich, Waldhof Mannehim and Bourdeux between 1972 and 1989. Him don coach African kontris like Gabon, Niger Republic , Burkina Faso and Nigeria. Na for 27th May 2020, President of di Nigeria Football Federation NFF Amaju Melvin Pinnick announce say di Federation and Rohr don agree on im new contract. Di target wey NFF give am na to win di 2021 Africa Cup of Nations wey Cameroon go host and to qualify Nigeria for di Qatar 2022 FIFA World Cup." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59336339 +entertainment Christmas songs, December holiday parties, carol and travels - Nigeria government give rules for di festive period Di Presidential Task Force on Covid- 19 don warn Nigerians to avoid Christmas carol, non-essential travels, family get together and anything wey fit escalate di cases of coronavirus for di kontri as di year dey end. Di Task Force issue dis warning during their weekly Covid- 19 briefing. Dem say Nigeria don rank fifth kontri for Africa wit di highest cases of Covid- 19 and deaths. Chairman of di PTF, Boss Mustapha, di national coordinator, Sani Aliyu, Minister of Health, Osagie Ehanire and di Director-General of di Nigeria Centre for Disease Control, Chikwe Ihekweazu wey tok on di state of Covid- 19 for di kontri fear say cases of coronavirus for di world don pass 63 million and kontris wey get number of infections na kontris wey Nigeria get political, business and family relations wit. Dem say make America witness more cases of Covid 19 infections afta di Thanksgiving holiday, make di same for no happun for Nigeria, dem advice say; https://www.bbc.com/pidgin/tori-55141660 +business Cannabis Crop: Malawi ask Mike Tyson to be dia cannabis ambassador "Malawi agriculture ministry don write letter to former world heavyweight boxing champion Mike Tyson to be dia ambassador for di kontri cannabis crop. Minister Lobin Lowe say di legalisation of cannabis last year for Malawi don create opportunity locally and internationally. Di ministry say di United States Cannabis Association na dem dey help arrange di deal wit oga Tyson. ""Malawi fit no go alone sake of say di industry dey complex and dey need collaboration. I go therefore like to appoint you, Mike Tyson, as Malawi Cannabis Branch ambassador,"" Mr Lowe bin write. Tyson also be entrepreneur and don invest wella for one cannabis farm. Local tori pipo report say Tyson dey expected for Malawi last week but dem postpone di visit. Malawian cannabis, particularly di one wey dey popular as Malawi Gold, dey considered by recreational smokers as one of di finest. For October 201, Mike Tyson bin launch one company, Tyson 2.0, Cannabis company wey go run across di whole of US. According to Mike Tyson Cannabis don play better role for im life, and now, di ogbonge boxer and cultural icon dey re-enter cannabis space wit new company wey go dey sell Tyson-approved weed products across di U.S. ""I never feel dis healthy for my life, I never feel dis clear for my life,"" Tyson tok. E say na cannabis bring major improvement to im mental and physical well-being, and e dey happy to tok say e never get any time wen e bin take so few pills. Di heavyweight champion don gain respect sake of im love for di plant . Tyson add say im new company go bring different choice to customers wey also like im creativity and taste for cannabis. Di new company, Tyson 2.0, go be step up from Iron im first cannabis brand, wey dey offer different products including everything from im personal favourite, flower, to concentrates, edibles, beverages, and pre-rolls. Oga Tyson na im go be di company chief brand officer and maybe di chief product tester." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59390339 +entertainment Grammy Awards 2022 postponement: Why organizers postpone di biggest music event Di 64th annual Grammy Awards Show wey suppose hold for US later dis January 2022 don dey postponed sake of coronavirus. Statement from di Recording Academy and CBS wey be di organisers of Grammy Awards 2022 say to go ahead wit di event go dey very risky wit di uncertainty wey di Coronavirus Omicron variant get. Di event wey pipo reason as di music biggest night bin dey scheduled to hold on 31 January for Los Angeles. Organisers say dem go announce future date soon. Dem add say di health and safety of di music community, di live audience, dia employees na top priority for dem. Nigerian musicians like Wizkid, Burna Boy, Tems, and Femi Kuti dey nominated for dis year award. Other African nominees include Angelique Kodjo, Rocky Dawuni, Wouter Kellerman and Black Coffee. Di 2021 Grammy wey Nigerian musician Burna Boy win di Best Global Music Award for im Twice as tall album bin dey postponed to March 2021 dat time. And dem do am online sake of di rising infections for Los Angeles abd di State of California. Many events dey postponed for 2021 sake of Covid- 19. Di emergency of Omicron variant for di end of 2021 don dash many pipo hope say di pandemic no be like wetin go end anytime soon. Organisers of some big events don dey cancel or postpone am sake of di spread of Omicron variant. Sundance film festival don cancel all in-person events for Utah sake of di rapid spread of Omicron. Di organisers inside statement say all dia independent movie premieres and events go take place online. Vault Festival 2022 also cancel dia event, three weeks before di arts festival wey dey hold for three months suppose start. Di VAULT Festival na annual celebration for emerging theatre artists for London. Di three-month schedule dey features hundreds of fringe theatre shows, cabaret, and musicians. Critics Choice Awards wey suppose hold on January 9 don dey postponed. Organisers go announce new date. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59898139 +politics APC National Committee dissolve party from state to polling unit level "Nigeria ruling party All Progressives Party (APC) announce, say dem don dissolve dia party for state, zonal, local goment, ward and polling unit level. Dis announcement come after di emergency meeting of di national executive council wey di party do on Tuesday 8 December for State House, Abuja. Some members wey no dey di capital city through video calling alias virtual, in di presence of di president Muhammadu Buhari, and oda big big politicians inside di party. APC Twitter handle wey dem use release di statement, no carry di reason why dem decide to dissolve at every level (except national) but opposition Peoples Democratic Party (PDP) don suggest say na because of bad governance. Inside letter wey PDP comot on di same day, dem say APC ""failure, big corruption, recession, violence, kill-kill and hardship wey pipo dey face"", na im cause di ruling party to ""finally dissolve"". APC say members of di executive from state, zonal, local goment, ward and polling unit wey dem dissolve, go now serve as caretaker members." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55237011 +entertainment For di joy of jazz "Olakunle Tejuoso stand for di middle of im record store, Di Jazzhole, im wear one turquoise modern 'buba' and 'sokoto' as im dey tok to staff wey dey rearrange books ontop shelves. Im start to tink about tins wey im love to do during e childhood. ""Well, first of all I don dream of to own my own record store... I dey always collect music wen I be small boy. ""I see am as natural way to go afta I leave school to continue di hobby of my childhood,"" na so Tejuoso tok. Di Jazzhole, wey currently dey for Awolowo Road for Nigeria commercial capital, Lagos, first open business for 1991 for smaller space elsewhere in di city. Nowadays, for time wen Afrobeats dey enjoy airplays for radio and for nightclubs, Di Jazzhole position imself as custodian of a different type of music. As a result, di record and book shop na one of Lagos favourite hideaways to go back in time and enjoy old school records through contemporary ears. ""We open primarily to sell jazz and African music essentially, black music essentially with an emphasis on."" Vibrant jazz scene bin dey for 1990s, but e don now give way to oda types of music. ""[My customers] na men wey get money and CDs bin dey new den. Dem bin no dey just buy, dem also understand di music becos dem don actually see a lot of di musicians. ""Dem don travel go abroad before and get enough money to go to festivals."" Tejuoso say dis days pipo get more appetite for jazz funk and smooth jazz. ""Di younger generation dey a bit different from wen we bin dey grow up."" Di Jazzhole na also di venue for live performances. Tejuoso say di live events start as way to sell di music. ""You get to remember say we bin dey operate before internet come. Dat time di only way to sell records na either you use radio or you find ways to draw pipo into di shop. So you get show and den you sell di records and den you spread di word."" Di Jazzhole don welcome many performers wey include Asa, Brymo and most recently Nneka. While Tejuoso tink about di memorable events of di 90s, im call e wife, wey be co-owner of di shop, to ask for her own. ""For me na still di [Fatai Rolling] Dollar days. In terms of musicianship, na those old guys,"" na so she tok. Tejuoso look back on wen one of di pioneers of highlife music, Fatai Rolling Dollar, share stage wit singer Keziah Jones. ""Just di interaction or di combination of someone from dat period [di 1950s] wit musicians from di 90s. ""I find am interesting and also di audience too, di fact say we dey work wit older generation musician and dey able to actually attract younger audience."" ""Di Asa one I no go forget am. I no go forget am becos many pipo bin dey dia, di shop bin dey bubble,"" na so im wife tok. As di demand for music by African artists begin grow, Tejuoso see am as duty to not just be pesin wey dey keep music but also as producer. Dis wan make am to start e own label for 1995. ""In di 90s, most of di stuff we bin dey get we dey import African music from Europe or somwia abroad. ""I just wake up one day and say at least we suppose get our own wey we dey produce and export too. Dat na how we take start wit label."" Despite say di iazz scene now dey different and dey exist side by side with more popular types of music, Tejuoso believes say room dey for Jazz to do well for dis market. ""If jazz go get any future here, e go need to turn into our own language. We go need rework am into our DNA in a way."" Artists and ogbonge pipo like Malian singer Salif Keita, Black Panther actors Lupita Nyong'o and Danai Gurira and King Mohammed VI of Morocco don visit di store. Wit plenti books, CDs and vinyl records, di scent of coffee wey dem dey make and di sound of jazz for di background, Di Jazzhole don position imself as di spot for lovers of jazz. ""For me, jazz dey more serious wia pipo dey actually come to listen to di music and not smoke and drink over di music. Jazz na different way of just receiving di vibe of music""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49923609 +entertainment Erica BBNaija: Kiddwaya na Ngozi Nlewedim Deputy afta she become new Head of House for BBNaija lockdown season 5 "Ngozi Nlewedim AKA Erica don become di new head of house of Big Brother season 5 afta she win di HoH Challenge dis evening. As Head of House, Erica don get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week. She also get di power to pick one housemates wey go be her deputy and enjoy dis privilege with her. As as fans of di reality TV show dey expect, Eric pick one of her paddy-paddy Terseer Kiddwaya AKA Kiddwaya and e ""gladly accept."" Erica name Kiddwaya as her first choice followed by Laycon and later Ozo big brother say she no fit put Ozo for di list because im just leave di Head Of House position. so she come replace Ozo with Prince. 14 housemates dey up for possible eviction dis week out of di 16 wey still remain for di house afta Erica pick her Kiddwaya as her deputy as e be say, she and her deputy don automatically get immunity. See di full list: On Sunday, Eric and Tochi comot for di house afta Ka3na and Lilo don bin comot last week Sunday. Voting go start on Monday and end on Thursday." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53730230 +sports Serena Williams go pay $10,000 fine afta she spoil Wimbledon court "Seven-time Wimbledon champion Serena Williams don get fine of $10,000 (£7,988) on top accuse say she damage one of Wimbledon courts wit her racket during practice before di Wimbledon tournament start. Di All England Club na im sama dis fine give Serena afta di incident happun during one practice session before dis year tournament for di Club. Dem don first bin fine her $10,000 for di All England Club sake of say she smash her racket on for di court during one second-round victory ova Christina McHale for 2016. No be only Serena dis tin don first happun to, Dem fine Australia tennis player, Bernard Tomic im full Wimbledon prize money of $58,500 last week sake of say e no meet di ""required professional standard"" during im weak 58-minute first-round defeat wey Jo-Wilfried Tsonga give am. Italy player, Fabio Fognini get fine of $3,000 (£2,396) afta e tok say 'make dem bomb Wimbledon.' Fabio wey be 32-year-old make dis statement wit im native language during im third-round loss to Tennys Sandgren on Saturday. Anoda Australian, Nick Kyrgios don get fine twice -- $3,000 and $5,000 -- during dis year championships sake of say e no behave well like sportsman during im first and second-round matches. Uruguay pesin, Pablo Cuevas and Aryna Sabalenka from Belarus don also get fine of $10,000 sake of say dem no behave well like sportsman." https://www.bbc.com/pidgin/sport-48926702 +business Ghana traders lock up shops of foreign traders for Eastern Region for fresh trade wars "Ghana Union of Traders Association (GUTA) members lock up de shops as protest against foreigners who dey operate retails shops. Retail traders for New Juaben South Municipality as part of when dem describe as peaceful demonstration, lock some of de shops by force. ""Police for prevent illegal trading"" be some of de writings dem put on placards during de protest. According to GUTA members, de laws of Ghana no dey allow for foreigners to engage in de retail market. During de lockdown process, de Ghanaian traders and one foreign trader who resist de locking of en shop almost turn chaotic. Public Relations Officer of GUTA for Eastern Region, Darlen Nana Boateng talk Accra-based Citi News say ""de tin turn chaotic small but that no be de plan we come with."" ""He open de shop dey talk we say he go work, he no go comply to de directive"" he add. Ghana den Nigeria traders over de years dey fight each other inside de retail trade business. For most Ghana traders, dema Nigerian counterparts for engage only is wholesale business based on Ghana laws. But for Nigerian traders, dem believe say free trade among ECOWAS countries dey allow make dem operate in Ghana freely. Sake of that GIPC Act which dey require foreigners to have $1 million minimum capital to do business in Ghana no be proper. Around September last year, Nigeria House of Representatives, Femi Gbajabiamila visit Ghana Prez Nana Akufo Addo to discuss de trade wars dem ways to resolve am. Despite de diplomatic talks, some Nigerian traders for parts of Ghana no dey fit operate sale of dema shops still dey under lock and key. Over 40 foreign owned retail shops for Ghana dey under lock and key as part of protest by local traders." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58612488 +politics Biden tell Japan say e ready to use force defend Taiwan "U.S. President Joe Biden say on Monday say im ready to use force to defend Taiwan. Biden tok dis one as part of series of critical comments about China, during im visit to Japan. Na im first trip to Japan since im enta office and no so Japanese Prime Minister Fumio Kishida stand dia dey look. But one of im aide say di comment no mean say U.S. policy on di self-ruled island don change. Di US president comment appear to dey different from existing U.S. policy of so-called strategic ambiguity on Taiwan. China consider di democratic island as dia territory, part of ""one China"". And Beijing say na di most sensitive and important issue for dia relationship wit di United States. Wen one reporter ask Biden if United States go defend Taiwan if dem attack am, di president answer: ""Yes."" ""Dat na di commitment wey we make,"" Joe Biden say, during one joint news conference wit di Japanese leader. ""We agree wit one-China policy. We don sign am plus all di intended agreements wey dem make inside. ""But di idea say, dem fit to take am by force, just take am by force, no just dey, no just dey appropriate."" Im add say im dey expect say dat kain tin no go happun or dey attempted. Following Biden comments, one White House official say e no get any change for policy towards Taiwan. Di president national security aides shift for dia seats and bend dia heads, dey study Biden closely as im respond to di question on Taiwan. Plenti bin look down as im make wetin resemble not so clear commitment to Taiwan defence. Biden make similar comment about defending Taiwan for October. During dat time, one White House tok tok pesin say Biden bin no dey announce any change in U.S. policy. And one analyst refer to di comment as ""gaffe"" or blunder. United States bin don agree long ago say na one China, including Taiwan. But it e don adopt im ""strategic ambiguity"" on di question of weda e go involve imsef in military conflict over di island. Di tok dey come as Biden make tough comments about China increasingly self-confident for di region. Di president say im hope say Russia President Vladimir Putin go pay price for im invasion of Ukraine in part to show China wetin e go face if e invade Taiwan. Di comments dey likely to both provoke Beijing and overshadow di koko of Biden Japan visit, wey be to achieve one Indo-Pacific Economic Framework. Di framework be broad plan wey go provide economic pillar for U.S. engagement with Asia. Im trip include meetings wit di leaders of Japan, India and Australia, for di ""Quad"" group of kontris." https://www.bbc.com/pidgin/61550191 +sports Manchester vs Newcastle: Premier League Predictions for match week four, time and how to watch "All eyes - and ears - go dey Old Trafford on Saturday. Na wia Cristiano Ronaldo dey expected to make im second debut for Manchester United. Dia game against Newcastle na 15:00 BST dat na 3pm West African time. ""I no think say Ronaldo go start,"" na so BBC football expert Mark Lawrenson. ""But im go definitely play some part - and, no, I no go dey surprised at all if im score."" See Lawrenson Premier League predictions for match week four. Dis week im guest na singer and guitarist Justin Young from indie rock band The Vaccines, wey im new album Back In Love City go dey out on Friday. Justin na United fan wey dey excited for di return of Ronaldo, but say im no dey sure of wetin to expect from di Reds dis season. ""Once again we dey start di season wit wetin if you look for paper, na correct team - maybe even better wit di return of CR7,"" Im tell BBC Sport. LAWRO PREDICTIONS Games go kick off at 15:00 BST unless otherwise stated SATURDAY Tottenham neva do anything spectacular so far but dem don do really well to win every Premier League game 1-0 - especially because I feel say dia defence na weak link. I'd still fancy Spurs to win dis one and continue their 100% winning start, even though Son no dey fit, but I no dey to worried about Crystal Palace wait for dia first league win under Patrick Vieira. Lawro prediction: 0-1 Justin prediction: Dis game go tough for Palace. Dem no dey look great, but Spurs good. 0-3 Arsenal results so far dey very bad so far but surely dem go get something out of dis bottom-of-di-table clash. We know say Norwich go fight hard dis season to avoid relegation. Lawro prediction: 2-0 Justin prediction: Arsenal get better players pass Norwich have, but as tins be now e no look good. Norwich feel say dem fit get something dia. 1-1 Na so far, so good for Brentford wey still dey unbeaten afta three league games. Brighton go expect a noisy atmosphere like di one wey we saw when di Bees beat Arsenal for di first game of di season because di home fans go just dey enjoy dia self. Justin's prediction: Brentford na classic newly promoted team wit plenty ginger - , so I dey support di Bees here. 1-0 As I dey tok, Manchester City still dey hope say dem go dey allowed to play Brazil duo Ederson and Gabriel Jesus but I still fancy them here without those two, even though e go mean say third-choice keeper Scott Carson go step in because Zack Steffen dey also unavailable. Leicester get a bit of history against Pep Guardiola' Manchester City, including beating them for last month Community Shield, but di Foxes go face a different animal dis time. Lawro prediction: 1-2 Justin' prediction: I no want to write Leicester off, but Manchester City dey look pretty strong. 1-2 Newcastle badly need a win, but Old Trafford, on di day wey Ronaldo dey return, no be di place or time to get am. Lawro prediction: 3-0 Justin prediction: Based on Ronaldo history and how im dey always marks every occasion to do something special, I dey expect a goal from am and a win for Manchester United, based on say Newcastle no dey form right now. 3-0 Southampton na another team without a victory so far but I feel say their performances better pass their results for their first three games. West Ham, meanwhile, don win two out of three and go maintain dia 100% record if to say dem no allow dia lead slip twice for home against Crystal Palace before di international break. Lawro's prediction: 2-1 Justin's prediction: 1-0 Watford don lose their past two games afta dem starting their season with a win ova Aston Villa and I no dey see that run ending dia weekend. Wolves dey without a point or even a goal so far but dem don create plenty chances and surely that go soon change , whether Mexican striker Raul Jimenez dey allowed to play or not. Lawro's prediction: 1-2 Justin's prediction: Dis one dey hard to call. 2-2 I bin dey impressed by Chelsea for dia draw wit Liverpool before di international break - Dem bin play well wen dem bin get 11 men and dem still do well when dem go down to 10. Aston Villa no go lack energy or effort but di Blues go dey too strong for them. Lawro prediction: 2-0 Justinprediction: Chelsea go win dis one. 3-1 Leeds form no too solid like dat so far dis season, but I feel say dem go struggle, to bounce back I dey go wit Liverpool. Di Reds go plenty of opportunities in front of goal. Lawro prediction: 1-2 Justin prediction: Dis go be good, open game but Liverpool suppose win am. 0-2 Everton start to di season dey good under Rafa Benitez and I dey expect dem to continue here. Burnley go make life difficult for them, of course - but the Toffees get enough quality to break them down. Lawro prediction: 2-0 Justin prediction: 1-1 How to watch di matches? Cable company SuperSport go carry all di matches live" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58519837 +politics Biden and Harris inauguration live: Watch Joe Biden, Kamala Harris US Presidential inauguration ceremony live "[Where to watch the inauguration?] Watch inauguration of Joe Biden here: Joe Biden inauguration live on Wednesday reach peak as im take oath of office as di 46th President of United State at about 11:48am ET (16:48 GMT) on Wednesday 20 January, 2021. Donald Trump no show face for di inauguration but im don leave White House for di final time of him presidency. Joe Biden take di oath of office inside US Capitol Hill, Washington, wey don dey protected alias fortified following a deadly riot wey happun for Capitol dis month. Alongside oga Biden, Kamala Harris make history wen she take oath alias sworn in as di nation [US] first woman vice-president. Some 25,000 troops go guard di inauguration ceremony, wey go miss di traditional hundreds of thousands of viewers alias spectators due to di coronavirus pandemic. Senator Amy Klobuchar, di oga of di inauguration planning na im start di proceedings. Lady Gaga na im sing di national anthem for di ceremony after di opening prayers. But Vice President Mike Pence and im wife sho face live for di inauguration, Some former Presidents and former Vice Presidents show face for di inauguration. House Speaker Nancy Pelosi dey attend di event. Jennifer Lopez sing ""Dis Land"" rendition during di ceremony. Oga Trump don take helicopter to di nearby Andrews base, where he im go speak and then board di Air Force One plane for Florida. Im be di first president to snub im successor's inauguration since 1869." https://www.bbc.com/pidgin/world-55737536 +sports Togo national football team attack: Survivors remember machine gun ambush, 10 years afta "On 8 January 2010, di Africa Cup of Nations for Angola bin only remain few days before e start. I bin dey di province of Cabinda, dey prepare to cover Group B for di BBC World Service, and bin also dey in charge of handing ova di BBC African Footballer of the Year trophy to di newly-crowned winner, Ivory Coast captain Didier Drogba. As di day waka dey go, unconfam reports of shooting, wey involve Togo national team, start to fly evriwia. Di detail bin no clear, but e clear say sometin serious don happun. How serious di tin be show wen I meet di squad as dem dey return to dia hotel for Cabinda city. I ask to speak to someone, dem immediately tell me say di team tok-tok pesin na dia best-known player - wey be Manchester City star Emmanuel Adebayor. Wen e siddon to tok, e give shocking details of di attack wey kill two members of di Togo delegation and result in life changing injuries to some odas. 10 years afta, dis na di tori from team members wey make global headlines and wetin happun afta. Togo squad bin dey in good spirits days before di 2010 Nations Cup. Dem just qualify back for di tournament afta dem miss out for 2008 and bin dey prepare to take on group wey feature some of di biggest names for African football - Drogba Ivory Coast and Michael Essien Ghana bin dey di same group. Before di tournament, Togo decide to camp for Pointe Noir for Republic of Congo, just over 100km from wia dem go play dia group games for Angola city of Cabinda. Cabinda dey separate from di rest of Angola, and instead of di Togo suad to fly from wia dem dey to di capital Luanda and den fly back north again, dem choose to drive. Dis decision later end with bad result. Afta di suqad relax in di evening, di night before - dem travel go di border. Players bin just dey laugh and joking amongst demselves for di bus. Angola security forces join dem for di border and suppose escort dem through di forest - wey be di base of one groups wey dey call for independence from Angola - to Cabinda city. Di squad no pay much attention to dia arrival. Dem no know say very soon dem go begin fight for di lives of everyone inside di Togo team bus. Di small convoy move from di border, to di road through di forest. Looking back 10 years, midfielder Junior Senaya recall di journey, and di moment everitin change. ""All of us bin dey enjoy, afta we don cross di border. Some of us bin dey busy dey listen to music. I remember afta 15 minutes wey we don dey drive we hear gunshot for di forest - we all laugh, make joke. Den serious shooting start."" Di first casualty happen before anybody even know wetin dey go on. Senaya remember Togo media officer, Stanislas Ocloo, bin stand to video dia arrival for Angola at di moment of di attack. Dem shoot kill am. Anoda player wey remember clearly those crazy moments na goalkeeper Kodjovi Obilale. Im life change for just few seconds, as e realise say dem don shoot am too. ""I hear di sound of di machine gun,"" Im tok, ""and for dat very moment I bin want move go hide, e bin dey as if dem nail me to chair. ""Dat na wen I see myself - both my belle and my back begin bleed. Dat na wen I begin panic. I say: 'Dem don hit me, help me, help me, I want see my daughter, my son. I no wan die here.'"" Even as im dey handle e own injuries, and fear, Obilale bin dey able to remember and tok wetin happun dat day. Im remember as assistant coach Amelete Abalo shout say dem don shoot am - di 54-year-na one of di pipo wey die for di attack. E remember one team-mate wey get military training call for weapon, so dat e go fit fight back. Di team bin no dey able to escape from di shooting because di bus driver - Mario Adjoua - don also wunjure for di start of di attack. Di convoy by-force stop, and serious firefight brake out between di attackers and di security forces. Memories of how long e last dey different, but everyone agree say na at least 30 minutes e last. Adebayor tok about how serious di longest half hour of e life dey. ""No be like say one or two guys shoot one or two times on our bus,"" Adebayor tell me afta im don dey safe place for di team hotel few hours afta di attack. ""We don dey di middle of dat for 30 minutes or even more. Our bus bin don stop and pipo bin don dey shoot our bus for 30 minutes. Can you imagine? Honestly na one of di worst experiences I don eva get for my life. ""Without di security den I no go dey here dey tok you. Maybe na my dead body you fit dey tok to."" Accounts of how e all end different - Adebayor describe one fleet of 4x4 vehicles arrive to take di squad away even as dem still dey shoot from di forest, while Senaya remember silence. But eventually dem take all of dem to hospital for di outskirts of Cabinda City, wia those wey noting do help carry dia dead and colleagues wey wunjure inside. ""Those na di times wey you realise wetin dey happun really, wen I take one of di players inside di hospital,"" Adebayor tok. ""Wen I come out, I see all di players, and everyone bin dey cry, everyone bin dey tok about dia family, calling pipo, calling dia mama, dey cry for phone. ""I think dat na di worst moment of dis day, because you fit see pipo tell dia last words, because dem think say dem go die."" Shortly afta dat di squad security men leave di squad on dia own wit few local officials. Wit dead and injured friends and colleagues for hospital, dem later walk short distance to dia hotel compound, without any security whatsoever. Dat na wia I come across dem, and I walk wit di team as dem waka go back dia accommodation. All four teams for di group bin dey stay for di same compound and Kolo Toure and couple of oda Ivorians come to offer condolences and find out wetin happen - rumours bin done already spread. Di survivors den sidon to eat - e bin dey late for evening, by dis point dem neva chop anytin since. Throughout di meal, evriwia bin dey silent. Di news of di attack make global headlines, and wia 24 hours earlier I bin dey able to walk in simply wit tournament accreditation, di next day heavy paramilitary security surround di hotel complex. Officials, goment ministers and representatives of di Confederation of African Football fly in from Angola capital Luanda, wit questions about wetin happen, who dey responsible, and why - for sometin wey go against tournament rules - Togo decide to drive instead of fly. Shortly afta di attack claim of responsibility comot from di Front for di Liberation of di Enclave of Cabinda, wey be separatist group wey never don accept di decision of di former colonial power, Portugal, to integrate Cabinda into Angola in di late 1950s. Several factions of di body bin dey, and which one dey responsible no dey clear - but e clear from very early on say dis no be attempted robbery. Anoda question lie for di presence Angolan security wey travel with di team. If Togo no dey authorised to drive to Cabinda, why and how come dem even get escort? And na di militarised escort cause di attack? None of dis questions get clear answers, even 10 years on - and at di time di most immediate issue for di players na to absorb wetin don happen to dem and decide wetin to do next. For several days e no dey clear to those of us wey watch from di outside wetin go happen. Rumours suggest say split bin dey between those for camp wey want continue wit di tournament and those wey want go home. In di end, Togolese authorities for Lome take decision, dem call di squad home to attend di funeral of those wey die and take part in ceremonies of national mourning - decision wey later make Caf ban dem sake of alleged ""government interference"" for football. Few days afta dia terrifying experience, Togo Sparrowhawks come out of dia hotel complex for anoda heavily armed convoy, dis time dem head towards Cabinda airport, and later leave. But di consequences of wetin happen no go easily leave di mind of those wey involve for di assault. Two pipo bin die and a number of odas seriously wound - di worst na di goalkeeper, Obilale. Initially tori spread say im die too. Dat no dey true, but e suffer serious damage to im spine, intestines, liver and bladder, and dem transfer am go hospital for South Africa, to begin e recovery. Since den e don face eight major operations and don get to rebuild e life, physically and emotionally. ""I done do lot of tins, and I happy say I do dem. I go back to school, take exams, work and write book,"" im tok. For long time im work wit children with special needs, as e help dem through di medium of football, and e don set up e own organisation to continue dat work. Obilale lose e livelihood - and almost e life - for Cabinda and e dey striking say im tok say na since only di change in leadership for di Confederation of African Football for 2017, wen current president Ahmad comot Issa Hayatou, na im e don get any meaningful contact wit di continental governing body. On Tuesday night Caf give am special award, 10 years from Cabinda, to recognise e achievement for im recovery, and wetin e dey do to help odas. Cameroon legend Samuel Eto'o na di host for Hurghada, and e be one of several former players wey don provide steady support. Odas na e former captain Adebayor and Ghana Ayew brothers - Andre Ayew and e brother Rahim bin dey part of di Black Stars squad wey play for Cabinda for 2010. Even those wey e no affect physically face significant challenges for di wake of di attack. Junior Senaya, wey be player wey help take Togo to dia remarkable first World Cup for Germany for 2006, bin dey only 25 wen e happen, but e football career end dat day. ""E bin dey psychologically catastrophic, e turn [tins] upside down,"" na so im tok. ""I really no fit recover... I find no reason at all to play football for my club because psychologically I bin dey shocked."" Now im dey study for e coaching badges. E last for half an hour, maybe a little more. Why and how e happen na still di subject of some dispute. But no one fit deny di human cost of dat short bus trip for Cabinda, 10 years ago. Additional research and reporting by Blame Ekoue for Lome and Victoire Eyoum in London." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51037938 +politics Boris Johnson win first vote to be Tory leader "Boris Johnson get di highest number of votes for di first ballot to select di Conservative party leader and next prime minister of UK. Oga Johnson receive 114 votes, Jeremy Hunt carri second wit 43, and Michael Gove third wit 37 votes. Dem knock out three contenders - Mark Harper, Andrea Leadsom and Esther McVey - for secret ballot dem do for House of Commons. Di two most popular MPs na dem Tory party members go vote for later dis month for di final round. Di winner of di contest go succeed Theresa May and dem suppose announce who e be for di week of 22 July. All 313 Conservative MPs follow vote for di first ballot. Oga Johnson say ""belle sweet to win di first ballot, but we get long way to go"". Foreign Secretary oga Hunt say im ""happy"" to carri second, say: ""Dis serious moment call for serious leader.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-48628944 +sports Champions League draw: Man City face Real Madrid, Liverpool play Atletico Madrid Manchester City go face Real Madrid while reigning champions Liverpool go play Atletico Madrid for di round of 16 of dis season Champions League. Chelsea go take on Bayern Munich for repeat of di 2012 final wey di Blues win while Tottenham go face RB Leipzig. Oda big big matches go see Borussia Dortmund play Paris St-Germain and Napoli go take on Barcelona. First legs of di draw go hold on 18, 19, 25 and 26 February while di second legs go shele on 10, 11, 17 and 18 March, 2020. Dis season final go happun on 30 May for di Ataturk Stadium for Istanbul, si ground wia Liverpool come from three goals down to win di 2005 Champions League against AC Milan. Dis na di full draw for di Champions League last-16 stage. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50810776 +entertainment BBNaija 2020 eviction: Nengi and Tolanibaj see me as competition - Ka3na "Ka3na, di first housemate to leave di Big brother Naija Lockdown season five show say Nengi and Tolanibaj see her as competition for di house. Her fellow housemates nominate her for possible eviction on Sunday afta she land for bottom four from di votes from fans of di reality television show. ""We be three different women and no reason why we suppose get bad feeling or feel like I be threat to dem."" Di Boss lady as she dey like to call herself tok dis one during her interview with BBC Pidgin on Tuesday. Ka3na wey be 26 year old lady from Rivers State south-south Nigeria bin dey very vocal inside di house and sometimes dat her character cause her to clash with some housemates for di house. For di second week, she and Tolanbaj clash sake of food mata and dia gbas-gbos trend wella for social media. ""Dem just dey feel uncomfortable around me."" Na wetin she add put. Ontop di lovey-lovey mata wey happun between her and Praise inside di house, she say dem no do kerewa but she call am her ""cuddle partner."" Ka3na dey tip Prince and Neo to win dis edition of di show. According to her, Prince dey smart and get a lot to offer. Meanwhile Lilo di second housemate to live di reality television show say her relationship with her boyfriend dey ok even though she and Eric bin dey entangled inside di house. She say she shock as Neo and Vee nominate her for eviction. Lilo wey add say she and Eric no dey relationship and she 'dey carried away' for di house say her biggest lesson na focus. Dis week, 16 housemates dey up for possible eviction out of di 18 wey still remain. Na only Ozo head of House and im Deputy Dorathy wey dey safe dis week." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53657033 +sports Di top 10 footballers for Forbes 2022 rich list Kylian Mbappe top Forbes 2022 rich list as di highest-earning footballer. Dis na di first time in nine years wey anoda pesin oda dan Lionel Messi or Cristiano Ronaldo be number one. Forbes dey estimate say Mbappe di Paris St-Germain striker wey be 23 years, go earn $128m (£115.2m) dis season. Mbappe PSG team-mate Messi na second on $120m (£108m) and Manchester United forward Ronaldo dey third on $100m (£90m). Neymar and Mohamed Salah complete di top five. Meanwhile Salah na di only African player wey dey di top ten. PSG and Brazil striker Neymar go earn an estimated $87m (£78.4m) for 2022-23 and Liverpool striker Salah go earn $53m (£47.7m). Di last player to top di list oda dan Ronaldo or Messi na former England captain David Beckham for 2013. Mbappe bin sign one new ogbonge three-year contract wit PSG for May, wey end speculation about a summer move to Real Madrid. Di France World Cup winner don win 11 trophies for di club, including four Ligue 1 titles, since im join dem from Monaco initially on loan for 2017. Erling Haaland, wey don score 19 goals in 12 games for Manchester City since im summer move from Borussia Dortmund, show face for di top ten list for di first time for number six. Di Norway striker na one of four Premier League players for di top 10 along wit Ronaldo, Salah and Manchester City team-mate Kevin de Bruyne. Haaland and Mbappe na di only players on di list wey dey under 30. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c06xjrx2340o +politics Femi Fani-Kayode joins APC: FFK many times e dump im party, why Fani-Kayode join APC "Femi Fani-Kayode, wey formally join APC, don explain di reason why im port from im former party PDP. Fani-Kayode finally join All Progressives Congress [APC] afta seven months of speculations. For February 2021, tori begin fly upanda say di former Nigerian goment minister wan dump im beloved Peoples Democratic Party for APC. On Thursday, September 16 na im Femi Fani-Kayode formally announce say true-true e do join di All Progressives Congress. President Muhammadu Buhari and APC Chairman National Caretaker Committee, Govnor Mai Mala Muni of Yobe state na im receive am for state house, Abuja. Oga Fani-Kayode afta di Presidential visit tok di reason why e decide to join di ruling party: E say na because im feel say na di right thing to do and FFK say im wan help di President to move Nigeria forward. Dis na afta e don deny several times say im no get any plans to join di APC. ""I think say na di right thing to do be dat. To put Nigeria first and to appreciate efforts wey goment don make in di couple of years. ""In terms of security, fighting terrorism, fighting insurgency and di most important thing na to remain as one nation."" FFK (as many dey call am) tok. Di former aviation minister under President Olusegun Obasanjo add say; ""If good things dey happun e better to appreciate, no be negative all di time. ""When di time dey right, we go change direction to join forces and join hands to move di kontri forward."" Femi Fani-Kayode former party, di Peoples Democratic Party [PDP] don react to im defection no come to dem as surprise . PDP say dem sabi di kain pesin wey FFK be. Dem say im recent waka don show say im no dey committed to di party as na commitment dey make party grow. Tok-tok pesin for di PDP, Kola Ologbodinyan tell BBC Pidgin on Friday say di party wish am well. Many Nigerians also receive di tori of im defection wit mixed feelings. Some express shock say im fit defect go di APC wit di way e don use mouth rubbish di party, others say dem no surprise as dem reason im political journey. Di 60 year old politician wey come from Osun state but grow up for Lagos na lawyer and politician. E describe himsef for social media as ""Lover of God, Servant of Truth, Voice of di Voiceless, Champion of di Oppressed, among others. Dis no be di first time, Femi Fani-Kayode go dey move from one party enta anoda. Di party wey im first dey wen e start im political career na di Nigerian National Congress for 1989. For 1996, e pitch im tent wit di National Democratic Coalition (NADECO) for abroad. Oga Fani-Kayode come back Nigeria for 2001 and become one of di founding members of di Progressive Action Movement (PAM), one political movement of young, new and dynamic politicians. For 2003, former President Olusegun Obasanjo appoint am as special assistant on public affairs. Obasanjo later appoint am as di minister of culture and tourism and later minister of aviation. E also serve as tok-tok pesin for di campaign organisation of former President Goodluck Jonathan, di PDP candidate for di 2015 presidential election. Fani-Kayode first dump di PDP in 2013 for APC until June 2014, later return to di PDP before di 2015 General Elections. As soon as e join di party again, e become popular for im criticism of di APC and di Buhari-led goment. Just dis year, key members of di Peoples Democratic Party wey be ruling governors na im don comot join di APC. Di Cross Rivers state govnor, Ben Ayade, Ebonyi state govnor, David Umahi and Zamfara govnor, Bello Mattawale. Di latest member of di APC say im dey instrumental to dia defection. He reveal say im dey follow more govnors tok to dump di opposition party and join di ruling party. Part of dem na govnor Seyi Makinde of Oyo State, Governor Bala Mohammed of Bauchi State, and Govnor Ifeanyi Uguanyi of Enugu State. Fani-Kayode add join say any opinion anybody get about im credibility sake of say im dey always change party na dia business." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58593890 +politics Nigeria News: Senate reject President Muhammadu Buhari request to amend di Electoral Act 2022 "Nigeria Senate don reject President Muhammadu Buhari request to amend di Electoral Act, 2022 on Wednesday. Last week, President Buhari bin write letter to the National Assembly to ask make dem amend di Act, by deleting Section 84 (12), wey im describe as ""defect"" wey dey conflict with di existing Constitutional provisions. Di bill bin scale first reading on Tuesday despite court order wey bar di Senate from taking action. But majority of lawmakers reject di bill during second reading on Wednesday. Before di voice vote, many of di lawmakers tok dia mind on why dem dey against di amendment of di Act and ask Senate to abide by di court ruling, wey stop National Assembly from tampering with di electoral law. According to Section 84 (12), pipo wit political appointment wey wan participate for elections must to first resign dia appointment before dem go fit participate for primary elections. One Federal High Court for Abuja on Monday bar di President Buhari, di Attorney-General of di Federation (AGF) and di Senate President from tampering wit di Act. Di judge, Inyang Ekwo, for im decision on di ex-parte application wey Peoples Democratic Party (PDP) file, say di Electoral Act don become valid law and dem no fit amend am without following due process of law. Di court specifically prevent dem from removing section 84 (12) of the Electoral Act or preventing im implemented for di purpose of di 2023 general elections. But Senate President, Ahmad Lawan, tok on Tuesday say di court decision no go stop di National Assembly from amending di Electoral Act 2022. E add say di court ruling dey against di 1999 Constitution (as amended) on Separation of Powers." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60669745 +health Madagascar coronavirus cure: Meet di man and kontri wey dey try 'save' Africa "For time wey di World dey look for answer to di global coronavirus pandemic, one kontri leader don dey di forefront of di battle. Madagascar President Andry Rajoelina don catch di world attention wit im 'herbal drink' wey im say dey cure coronavirus. Although di World Health Organization (WHO) don warn say di drink need further testing, some African kontris don begin enter queue to order am to test. On 8 April, president Rajoelina announce to di world di ""medicinal plant"" wey go see Madagascar"" change di course of history"" sake of im discovery. Despite wetin WHO tok, Rajoelina say pipo wey dey criticize im solution to coronavirus dey show di West attitude towards tins wey come from Africa. Im say ""If e be say na European kontri actually discover dis remedy, so much doubt go dey? I no tink so."" 46-years-old Rajoelina na long time businessman and na one-time Disk Jockey alias DJ. Im enter politics for 2007 wen im contest to be Mayor of Madagascar capital, Antananarivo. Rajoelina na di 7th president of di island nation, im don marry and get three children. Madagascar get 192 confam coronavirus cases according to informate from John Hopkins University. Out of dat number, 105 don recover and nobody don die from di virus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52631726 +sports Transfer News: Iwobi, Smalling and oda transfers wey fit happun before di window close on Thursday Arsenal don reject £30m bid from Everton to sign Nigeria International player Alex Iwobi. Tori be say di Toffees go return back to increase di money for di 23-year-old winger- but dia plan na say dia new bid no go pass £40m. Iwobi no wan leave but im go move if di two clubs agree a deal. Di English Premier League transfer window go end on on Thursday, 8 August by 5pm. Everton still dey eye Manchester United defender Chris Smalling to sign am on loan but di club reject dia offer. Smalling don play 323 times for Man Utd, im win di Premier League titles in 2011 and 2013. Romelu Lukaku agent dey London to try to sort out di striker future for Manchester United. Federico Pastorello go meet with representatives from Italian club Inter Milan, to try to find common grounds between di clubs. New Inter Milan coach Antonio Conte make Lukaku im number one target and im neva change im mind ontop di matter. Watford wan sign former Arsenal striker Danny Welbeck. Welbeck wey be 28 years leave Arsenal afta five years dis summer. Watford don follow Welbeck tok and dem believe say di England International player go help dia club if im stay fit. Welbeck wey be 28 years leave Arsenal afta five years dis summer. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49267957 +sports John Terry: Former captain go return for coaching consultancy role "Former captain John Terry dey comeback to Chelsea for coaching consultancy role for Chelsea club academy. Di former England defender go work in part-time capacity with players and coaching staff for Chelsea youth development programme from early January. Terry wey dey 41 years win 15 major honours for di 19 years wey im spend for di club as Chelsea player before im join Aston Villa, wia im be assistant manager from January 2018-2021. ""I dey happy to announce say I dey come house"" e tok for social media. ""Di flexibility na im important pass for both mysef and di academy as e go allow me to kontinu and develop my own coaching skills and ambitions side by side wit oda commitments"". Afta im pass through Chelsea academy, Terry score 67 goals for 717 appearances for di Blues and also get 78 caps for England. Terry spend im final year of active career for Aston Villa before im retire for October 2018 to become so assistant of Dean Smith. Im comot for July to pursue im managerial career. Head of Chelsea Youth Development Neil Bath add say "" we no fit wait for him to start"". ""Im go be great mentor for our players and big asset to our coaching staff dem"". ""John Terry experience for di game both as world class player and more recently as an assistant coach for Premier League, evribodi for dis building no fit value am enough""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59821837 +entertainment BBNaija evictions today: Tega, Boma, Michael, Peace chop eviction from Big Brother Naija show Tega, Boma, Michael and Peace don dey evicted from di Big Brother Naija show. Tega be di first to comot on Sunday tonight for inside wetin organizers of di Big Brother Naija 'Shine Ya Eye' reality TV show bin don tok say go be 'King-size Eviction'. Tega eviction dey followed by Michael, Peace and lastly Boma for wetin Biggie say na quadruple eviction show. All di housemates bin dey up for possible eviction on Sunday except, Jackie B and Jay Paul wey be di Heads of House. Jakie B and Jaypaul win oda housemates last week Monday to find di most keys and finish dia task for di weekly Head of House game on 30 August wey biggie introduce with a twist. Di last HOH game bin come wit a twist as Biggie announce earlier say dem go get two winners and e tag am 'The double Heads of House'. Out of di 15 housemates wey bin dey up for di possible eviction on Sunday; At di end, Saga, Saskay, Emmanuel, Nini, Cross, Angel, WhiteMoney, Liquorose, Pere, Queen and Yousef bin safe. Last week Sunday, three housemates - Maria, Sammie and JMK chop eviction for a triple eviction show. Di voting chart reveal say Tega, Peace, Boma, Michael, Saga and Nini dey di bottom six. Out of di four pipo Biggie evict on Sunday night, Boma and Tega own spark di most reactions becos of dia 'entanglement' for inside di show. Her closeness and 'kissing' escapades with Boma bin cause a lot of toks outside di house sake of say she be married woman. Tega however tell Ebuka afta dem evict her say she bin dey put up a 'show' and hope say di viewers enjoy am. Meanwhile, Boma tell Ebuka wen e ask am say im and Tega bin just dey 'cool'. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58446720 +business Nigeria Ministry of Foreign Affairs say quanta no dey between dem and Ghana "Nigeria Ministry of Foreign Affairs don deny report wey dey fly upandan say quanta dey between dem and Ghana on top decision to pursue di Nigerian high commission for dia Accra residence. Some tori pipo on Thursday report say diplomatic gbege dey afta Ghana allegedly remove Nigeria High commissioner Olufemi Michael Abikoye from im residence wey dey No.10 Barnes Road for Accra. Di Nigeria High commission release press statement on Friday say na lie be di tok say dem pursue dem from dia Accra residence. For di statement, wey Ferdinard Nwonye di tok tok pesin for di Ministry of foreign affairs sign dem say; ""Di ministry go like clarify say di property wey dem dey tok, na federal Ministry of Finance dey use am since 1957 on lease before dem later give am to di Ministry of Foreign Affairs. ""Di lease don expire and di High commission dey find way to renew di lease agreement with di host authority,"" e add. Dem tok say make pipo note am say di building as we dey tok no dey house either di residence of di High Commissioner, Chancery or staff quarters. ""Make pipo take note say di property no dey house either di residence of di High Commissioner or di Chancery or Staff quarters,"" Im tok However dem say toks dey go on between di Ministry and di host authorities and gbege no dey as di Ministry dey on top of di situation." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50980509 +health "Donald Trump coronavirus: Meet ""Hope Hicks"" White House Communications Director wey catch Covid 19" "President Donald Trump and First Lady Melania bin catch Covid- 19 afta im close adviser Hope Hicks test positive for di virus. Di president adviser wey be 31-year-old na former model wey no dey like to keep low profile. She no too like publicity. Hope Hicks replace Anthony Scaramucci as di president communications director when di presido sack am afta 10 days for office in 2017. She no get any background for politics, but she dey connected to di Trump family since five years ago. Her political career wit Oga Trump get as e be - as she dey resign from one role enta another she resigned from one role, only to return later to another different position for im team. So how pesin wit that kain low profile take get one of di most important jobs for di US goment? Hope Hicks start her career for public relations, and Ivanka Trump fashion company na one of her clients. She bin model for Ralph Lauren - and she also appear for di cover of a Gossip Girl spin-off book - she model some of Ivanka clothes as part of her job. Na as she dey work wit Oga Trump eldest daughter mean say Hope Hicks go catch di attention of di US president. He personally choose her for October 2014 to work in PR for im real estate company. Donald Trump later tell GO say im think say ""Hope dey outstanding"". For early 2015, she join politics when she follow Donald Trump go one journey wey later turn out to be di first part of im presidential campaign. She even help run im Twitter account, dey take note of wetin he go tok and dey order others wey dey di Trump organisation to tweet dem. When di campaign get more serious, she need decide whether to become a full-time political press secretary or go back work for di Trump real estate company. She chose di real estate company. But again, Donald Trump personally ask her to stay on im political team. She accept. Hope Hicks no dey really do interviews about herself, although she she dey always dey there wen Oga Trump dey follow tori pipo tok.ists. And when she start work wit di presidential campaign, she delete her Twitter account. Her Instagram profile dey private. Dis quote wey her former lacrosse coach give di Washington Post sum up her attitude well. ""[Hicks] prefer to have assists. She na di ultimate team player and competitor."" When Donald Trump become president, he create new role for Hope Hicks: White House director of strategic communications. Her way of dealing wit di president no be to try change am, but to allow him to wetim im wan do. According to a Politico article, Hope Hicks na one of di few true insiders inside Trump family, even having Shabbat dinners (special meals for di Jewish faith) wit Ivanka Trump and Jared Kushner. She na also one of di few wey meet di wit Donald Trump for May 2017. Hope Hicks resign for February 2018, one day after she confess to Congress say she sometimes dey tell white lies on behalf of Trump. Afta that she work for Fox News, but return to di president team earlier dis year. According to BBC White House reporter Tara McKelvey at di time, di reason she give simple. ""She no dey too tok but e be like say she sabi di president secrets.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54390669 +entertainment Dyslexia: Cross reveal to Angel say im get Dyslexia afta im bathroom fight wit Nini for Big Brother house "Big Brother Naija housemate Nini say she no go forgive Cross for wetin im tok, even afta im apologise to her afta dia fight. According to her she say her heart neva ready to do so. She tok dis wen Whitemoney wey di head of house for dis week call di two of dem together inside di blue room to settle di fight wey happun dis morning. Cross and Nini bin quarrel each oda on Wednesday September 15 sake of bathroom cleaning. Afta di whole fight Cross begin feel down e sitdon for di garden area na dia im break down start to cry. Angel later join am to try to comfort am. As she dey try console am im open up tell her say im dey suffer from Dyslexia. Dyslexia na learning disorder wey involve difficulty reading due to problems identifying speech sounds and learning how dem relate to letters and words Angel reassure am say im no dey dumb and say she go always dey here for am anytime im feel down. Dis week five housemates dey up for possible eviction dem be Cross, Angel, Emmanuel, Yousef and Saskay. At least one of dem go live Big Brother house on Sunday during di live eviction show. Di wahala start when Nini bin dey clean di bathroom dis morning and Cross bin wan bath. Cross bin no like di fact say Nini bin dey clean di bathroom before di housemates bath. Two of dem begin quarrel each oda on whether dem suppose clean di bathroom after Housemates bath finish or not. Di mata worse wen Cross ask Nini if she dey stupid. Dat word make Nini spark well - well na so she come begin curse back. ""Why you dey ask me if I dey stupid? You be dumbest pesin for dis house. Everybody know who di stupid pesin be for dis house, Na you Cross,"" Nini tok. Oda housemates begin hold di two of dem to make sure say dem no go physical." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58574768 +sports Manchester United footballer Mason Greenwood dey charged wit attempted rape and assault "Manchester United footballer Mason Greenwood don dey charged wit attempted rape, engaging in controlling behaviour and assault, di CPS tok. Prosecutors say di charges relate to di same complainant. Di 21-year-old footballer go face im first court appearance for Greater Manchester Magistrates' Court on 17 October, di CPS add am. Janet Potter, from Crown Prosecution Service North West, say dem don authorise Greater Manchester Police to charge Oga Greenwood wit attempted rape, engaging in controlling and coercive behaviour, and assault wey dey cause actual bodily harm. Dem say di alleged rape happun on 22 October 2021, while di alleged assault take place last December. Di charge of controlling and coercive behaviour relate to one period of time since November 2018. Ms Potter say dem make di charges afta specialist rape prosecutors review one file of evidence from police. She added: ""Di Crown Prosecution Service remind all concerned say criminal proceedings against di defendant dey active and say e get right to a fair trial. ""E dey extremely important say make no reporting, commentary or sharing of information happun online wwey wey fit in any way affect di proceedings."" Earlier on Saturday, dem arrestdi Manchester United footballer for allegedly breaching bail conditions. Im bin chop arrest on suspicion of rape and assault for January. Dem also question am about claims of making threats to kill. Di BBC understands say dem make di latest arrest for im home for Bowdon, Greater Manchester. For one statement, one representative for Greater Manchester Police say dem dey ""aware of one allegation regarding one 21-year-old man breaching im bail conditions and dem make arrest on Saturday"". Dem add am say ""enquiries dey go on at dis time"". Within hours of di online allegations for January, dem suspend Greenwood from playing or training wit im club until further notice. Nike end im sponsorship deal wit am and Electronic Arts remove am from active squads on im Fifa 22 game. Police arrest Mason Greenwood on suspicion of rape and assault for January. Greater Manchester Police say dem hear about di ""social media images and videos wey one woman post wey report incidents of physical violence"". Di woman bin post pictures and videos of di allegation for her Instagram story wey she caption: ""To everyone wey wan know wetin Mason Greenwood actually dey do to me"". She later delete di post. Mason Greenwood never respond to di allegations. Meanwhile, Manchester United say dem dey aware of di allegations Di club add say, ""Manchester United no dey condone violence of any kind."" Later Manchester United say Greenwood no go return to training until further notice. Greenwood wey United promote from dia academy make im debut for march 2019. Im don make 129 appearances for Manchester United and don score 35 goals." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c90gn0wq0lvo +entertainment Burna Boy go perform for Grammy Awards Premiere Ceremony Nigerian musician, Burna Boy go perform for dis year Grammy Awards Premiere Ceremony for March 14th. Burna Boy bin gbab nomination for di newly renamed Best Global Music Award for im album wey im call Twice As Tall. Dis go be im second Grammy nomination, im first one na for 2020 wen im be dey nominated for Best World Music Album for African Giant. Burna Boy dey slated to perform among oda Grammy Nominees wey include Camilo, Afro-Peruvian Jazz Orchestra among odas. Na Jhené Aiko dey host di event wey go hold from 9pm West African time on Sunday, March 14 and go show live for di Grammy Awards website. Di Award show go start immediately afta di ceremony by 2am West African Time di next day. Burna Boy no go be di first Nigerian wey go perform for di Premiere Show of di Grammys as for 2019, Seun Kuti bin get opportunity to perform along with im nomination https://www.bbc.com/pidgin/tori-56235620 +sports Ghana vs Comoros: Andre Ayew receive red card as Black Stars finish bottom of Afcon Group C table, Comoros make history wit first win Four-time champions of di Africa Cup of Nations Ghana don comot from di ongoing Afcon 2021 tournament for Cameroon. Dis na afta dem lose 3-2 to first timers for di competition Comoros- di small island kontri occupy di third spot for Group C behind Morocco and Gabon. Comoros also make history by winning dia first ever match for Afcon. Na El Fardou Ben Nabouhane first score for di islanders before Ghana reduce to 10 men wen Andre Ayew chop straight red card. Ahmed Mogni double di lead before di Black Stars fight back to make am 2-2. However, Mogni tap in im second goal for di 85th minute to pepper Ghana - dis na dia first group-stage exit since 2006. Di result don become one of di biggest shock for Nations Cup history as Comoros score for di tournament for di first time. Comoros wey dey 132 for Fifa world get chance to enta knock-out stage as one of di four best for third-place. Second Half don begin Ghana 0, Comoros 1. 45mins: Substitution for Ghana. Edmund Addo replace Abdul Rahman Baba. 46mns: Kamaldeen Sulemana win free kick on di left wing. 47mins: Defender block attempt by Abdul Fatawu Issahaku of Ghana. 49mins: Fouad Bachirou of Comoros miss attempt afta e shoot from outside di box. 51mins: Youssouf M'Changama win free kick for di attacking half. 52mins: Ghana midlfielfer block attempt from Youssouf M'Changama. 55mins: Offside, Ghana. Daniel Amartey try through ball, but Andy Yiadom dey offside. 56mins: Thomas Partey win free kick for di defensive half. 59mins: Offside, Ghana. Jordan Ayew trt through ball, but Thomas Partey dey offside. 62mins: Goal! Ghana 0, Comoros 2. Ahmed Mogni left foot shot from centre of di box give Comoros dia second goal. 64mins: Corner, Ghana. na Fouad Bachirou concede am. 64mins: Goal! Ghana 1, Comoros 2. Richmond Boakye use head from di centre of di box to di top right corner score. 67mins: Richmond Boakye win free kick for di attacking half. 68mins: Foul by Thomas Partey. 70mins: Richmond Boakye win free kick for di attacking half. 72mins: El Fardou Ben Nabouhane win free kick for di defensive half. 73mins: Corner, Ghana. Na Youssouf M'Changama conceded am. 75mins: Daniel-Kofi Kyereh win free kick for di defensive half. 76mins: Goaalll! Ghanda don equalise - Alexander Djiku na im score di goal. 78mins: Andy Yiadom of Ghana chop yellow card for bad foul. 79mins: Ghana defender block shot by El Fardou Ben Nabouhane. 81mins: Substitution for Ghana. Samuel Owusu replace Andy Yiadom. 84mins: Offside, Comoros. Faïz Selemani try through ball, but El Fardou Ben Nabouhane dey caught offside. 85mins: Goal! Ghana 2, Comoros 3. Ahmed Mogni left foot shot from very close range to di centre of di goal. 89mins: Attempt missed. Alexander Djiku right foot shot from outside di box misses to di right. 90mins: Substitution for Comoros. Nadjim Abdou replace Fouad Bachirou, Mohamed Youssouf replace Ahmed Mogni, Rafidine Abdullah replace Bendjaloud Youssouf. 90mins+3': Joseph Paintsil win free kick for di left wing. Full time Ghana 2- Comoros 3 1min: Jordan Ayew win free kick for di right wing. 4mins: Goal! Ghana 0, Comoros 1. El Fardou Ben Nabouhane score for Comoros wit shot from di centre of di box following afta a fast break. 6mins: Abdul Fatawu Issahaku win free kick for di attacking half. 8mins: Corner, Ghana. Na Younn Zahary conceded am. 8mins: Comoros defender save heading from Alexander Djiku of Ghana. 10mins: Thomas Partey win free kick for di attacking half. 11mins: Comoros defender block right leg shot from Thomas Partey. 13mins: Ibroihim Youssouf of Comoros win free kick for di defensive half. 14mins: Booking, Faïz Selemani chop di first yellow card of di match for bad foul. 17mins: Comoros keeper save shot from Kamaldeen Sulemana afta pass Jordan Ayew. 20mins: André Ayew win free kick from di right wing. 24mins: VAR Decision: Card upgrade André Ayew. 25mins: Dismissal, Ghana captain André Ayew chop red card. 26mins: Substitution for Comoros. Ali Ahamada replace Salim Ben Boina sake of injury. 28mins: Foul by Alexander Djiku. 29mins: Ahmed Mogni miss attempt miss as e play shot from di left side of di box. 31mins: Youssouf M'Changama of Comoros miss anoda attempt afta right foot shot from more dan 35 yards. 33mins: Comoros continue to press Ghana wit anoda attempt miss from Bendjaloud Youssouf. 35mins: Corner, Ghana. Na Fouad Bachirou conceded am. 38mins: Comoros keeper save right foot shot from Abdul Fatawu Issahaku. 39mins: Jordan Ayew win free kick for di attacking half. 40mins: Comoros keeper catch shot from Thomas Partey wey e shoot from outside di box is close. 42mins: Hand ball by El Fardou Ben Nabouhane. 43mins: Comoros defender block anoda shot from Thomas Partey. 44mins: Offside, Ghana. Abdul Rahman Baba try through ball, but Kamaldeen Sulemana dey offside. 45+2': Youssouf M'Changama of Comoros miss attempt afta right footed shot from outside di box. 45+3': First Half don end, Ghana 0-1 Comoros. Ghana line-up: 16. Wollacott, 17. Baba,23. Djiku, 18. Amartey, 2. Yiadom, 22. Sulemana, 8. Kyereh, 5. Partey, 7. Issahaku, 10. A Ayew, 9. J Ayew Comoros line-up: 1. Ben Boina, 4. Zahary, 15. Youssouf, 12. M'Dahoma, 10. M'Changama, 22. Bakari, 7. Selemani, 17. Youssouf, 8. Bachirou, 20. Mogni, 21. Ben Nabouhane. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60043251 +entertainment Caitlyn Jenner: Reality star announce plan to contest for California govnor "Caitlyn Jenner don announce say she don file di paperwork to run for California govnor. Di former Olympic athlete and reality TV star confam di news for her Twitter account early on Friday. Authorities fit confam a recall election inside di state dis month afta one petition against current governor Gavin Newsom reach di number wey law require to trigger anoda vote. Dey fit ask voters if dem want oga Newsom to stay or anoda candidate. If dis recall election go ahead, e go be di fourth governor recall for di history of US. Di current governor, Gavin Newsom don receive plenti criticism for di way im handle di pandemic and as di infections start to fall, business owners still dey criticise am for enforcing restrictions. According to di Axios news site, Madam Jenner don put together one team wey include some of former President Donald Trump advisers. ""Californians want beta and deserve beta from di governor,"" Caitlyn Jenner tok for her recent statement. ""For too long, career politicians don over-promise and under-deliver. We need leader with di vision and resolve to see say everytin come through,"" she add. Caitlyn Jenner promise say her campaign go be one of ""solutions"" and provide ""roadmap back to prosperity to turn dis state around"". She add say she go formally launch her campaign for later date. Madam Jenner describe herself as ""proven winner"" for her statement plus add say she be di ""only outsider who fit stop Gavin Newsom disastrous time as a govnor"". Caitlyn Jenner na highest-profile American to come out as transgender. She announce say she wan transgender for 2015 for one interview with broadcaster Diane Sawyer on ABC. Caitlyn Jenner wey also be former athlete don win gold medal for di Montreal Games for 1976. Before she transition, she bin dey married to Kris Jenner and two of dem get two daughters, Kendall and Kylie. Di family na stars of di hit reality show 'Keeping Up with di Kardashians. Caitlyn Jenner tok say her step-daughter Kim Kardashian na big supporter of her transitioning. California no be stranger to celebrities running for govnor. Arnold Schwarzenegger win di 2003 recall election, e beat adult film star Mary Carey and former child actor Gary Coleman to win. Oga Schwarzenegger step down for 2011, afta seven years for office. For 1966, former actor Ronald Reagan win di govnorship of California and e win re-election four years later. Before e bin go into politics, e don bin appear for more than 50 films and later become president of di Screen Actors Guild. But im biggest role dey front dey come, for 1980, dem elect am as US president, e serve two four-year terms." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56865360 +sports NBA Finals: Giannis Antetokounmpo shine as Milwaukee Bucks beat Phoenix Suns to win dia first title for 50 years "Giannis Antetokounmpo score 50 points as di Milwaukee Bucks win dia first NBA title for 50 years with 105-98 victory ova di Suns. Di Bucks seal di 4-2 series win in front of crowd wey reach 17,000 as 65,000 celebrate outside di Fiserv Forum. Tori be say dem be di fifth team to win di best-of-seven finals series afta dem lose their first two matches. ""I dey happy say I help dis team for Milwaukee,"" na so Antetokounmpo. Di Suns bin dey eye dia first NBA crown for dia 53-year history, afta dem don lose NBA Finals series for 1976 and 1993. But, dem bin not fit stop Antetokounmpo, wey become only di seventh player to register 50 points for a Finals game. And dat na di third game for di series wey di 26-year-old don manage at least 40 points and 10 rebounds. Antetokounmpo now don join di likes of Michael Jordan and Hakeem Olajuwon to collect a regular season MVP, NBA Finals MVP and NBA defensive player of di year awards. ""I want thank Milwaukee for believing in me. I want thank my team-mates for playing hard wit me,"" Antetokounmpo tok. Bucks coach Mike Budenholzer describe di Greek forward as ""special human being"". ""I don learn so much from am. Him na special leader,"" e tok. ""These players na champions every day. Dem work hard to improve every day."" Na wen Budenholzer be four years old na im wen NBA legends Kareem Abdul-Jabbar and Oscar Robertson bin lead di Bucks to dia only previous NBA title for 1971, Dat time some of di current players' parents dem neva born dem sef. Unlike di 2020 NBA Finals wey dem bin play am without fans, di Bucks' win cause wild party inside di arena and for di streets of Milwaukee. More than 10% of di city population, gada for Deer District outside Fiserv Forum, some fans bin wait in line for five hours before di game to ensure say dem get seats. Isaiah Tyler, one 43-year-old painter wey dem born and raise for di city, say: ""Dis na history. I grow up here and don see many bad games - so dis na pay-off."" ""Milwaukee na very segregated city, so to see us all together, all races, for one cause, dis na how di world suppose be."" Tom Cogdall, one 63-year-old retired Army officer wey dey live for Milwaukee, add say: ""I remember 1971. Dat na 50 years ago, we need am.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-57918519 +entertainment Burna Boy African Giant album dey totori pipo Plenti pipo dey hala ontop social media afta Burna Boy release im new studio album, di African Giant. Im release di album afta one listening party e organise for California, US on Thursday night. Di 19 track album feature both local and foreign artists like Zlatan Ibile, Damien Marley, Angelique Kidjo, Jorja Smith and Future. Dis na big month for Burna Boy as e appear for di Late Night Show ontop American TV, with Jimmy Kimmel, before den im follow for di ogbonge artistes dem from Africa wey America musician Beyonce feature inside her 'Lion King The Gift' album. Wetin pipo dey yan about di song. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49110622 +sports Didier Drogba: FIF reject Ivorian footballer candidacy to be Ivory Coast FA president "Di electoral commission of Ivory Coast football federation don reject former Ivorian international footballer, Didier Drogba as presidential candidate. Dis announcement dey come afta dem release di list of accepted candidates and di Ivorian footballer name no dey dia. Didier Drogba, wey bin dey struggle to meet di requirement for di number of sponsorships finally dey successful to submit im candidacy afta many attempts. Di former Chelsea player say im wan contribute to di rebirth of Ivorian football as tins no dey go well for di organisation. Di electoral commission accept di candidacy of Yacine Idriss Diallo,wey be former 3rd vice-president of di FIF, di current vice-president of di Federation and president of di League Sory Diabaté. Didier Drogba get five days to appeal. Di former captain of di Ivorian Elephants bin suffer one heavy blow for mid-July, wen diAssociation of Ivorian footballers (AFI) no gree sponsor am. Then, di International Federation of Professional Footballers Associations (Fifpro) suspend AFI say dem no ""follow wit wetin dey di books "" afta dem refuse to support Didier Drogba's candidacy for di head of di FIF. Didier Drogba later succeed to get eight sponsorships and di support of one of di five interest groups wey dey necessary to apply for di election. ""No be to just become di president of di FIF , I dey afta, but na di mission wey dey bind how e dey function,"" di 41-year-old athlete tok. ""Our football no dey go well (...) we dey committed to contribute to how dem go reborn di Ivorian football,"" di player wey don hang im boots since di end of 2018 add am. ""I don come back and I dey determined to contribute my stone to di building, to di renewal and to di development of Ivorian football,"" he add am. He also believe say e dey very important for am to give back to Ivorian football, everything dem don give am." https://www.bbc.com/pidgin/sport-53935956 +entertainment Tekno break law with im 'pole dance' video? "Few days after video wey show Nigerian musician Tekno dey dance with ""half naked"" women inside van for Lagos comot for social media, tori be say Nigeria police don invite am to come ansa qweshion ontop di mata. Many Nigerians bin tink say di girls wey dance inside di transparent van been dey promote strip club until di musician claim responsibility for di scene. Lagos police spokesman Elkana Bala, confam to news men for Nigeria say dem question Tekno wey im real name na Augustine Kelech and im producer togeda with two girls wey dey inside di video, but di qweshion some don dey ask na which law di musician break? According to Section 136 of di Criminal Law of Lagos, 2015, any pesin wey commit any act of gross indecency with anoda pesin for public don commit offence and fit face three years imprisonment. Section 134 (a) also tok say indecent act for public place fit land di pipo wey engage in di act to two years imprisonment. Fred Okey Nzeako wey be constitutional lawyer tok say anybody wey break dis kain law need to ""answer questions"" as to why ""dem wan scata di morals of di society."" For am, ""no sane society go tolerate or allow any human being to walk naked on di street or perform any indecent act. ""Person wey don break dis law only excuse na if e dey experience mental problem,"" na so Fred tok or if di offender get any defence for dia action. Tekno don since apologise for di incident, im explain say ""reason no dey for am to dance inside Truck around Lekki, Lagos State."" Im say e been dey shoot music video for im new song and na because ""some of di cars wey dem been dey use, break down during di shoot,"" na im make dem use di transparent van to move to di next location." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49261876 +entertainment Burna Boy Twice As Tall track list plus oda tins you suppose know about di award winning Nigerian singer wey make pipo dey hala "Fans dey react to Nigerian award winning singer Burna Boy latest album Twice as tall wey drop early on Friday morning Nigeria time. Di song wey be di 'African Giant' singer fifth album, na Sean 'Diddy' Combs, US ogbonge rapper Sean Diddy Combs and Bosede Ogulu, Burna Boy mama be executive producer. For di 15-track project, di 'Ye' singer feature oda ogbonge singers like Stormzy, Coldplay's Chris Martin, Youssou N'Dour, Naughty By Nature, and Sauti Sol. Stormzy na British rapper, singer and songwriter. Im blow for UK underground music scene through im different freestyles and classic beats. Im first grime album reach number one for UK Albums Chart come win British Album of di Year for di 2018 Brit Awards. Im na British singer, song writer, record producer and philanthropist. Chris Martin na lead singer and co-founder of di rock band Coldplay. ""Yellow"", di popular song wey im band release for 2000 make dem blow plus get dem dia first Grammy Award nomination. Dem win Grammy award for two of dia albums A Rush of Blood to di Head and Viva la Vida. Coldplay don sell pass 100 million records all ova di world. Black America hip hop musicians Naughty by Nature don dey sing togeda since 1986. Dem break up for 2013 but reconcile again for 2016. Dem don win three Grammy Awards for 1991, 1993 and 1995. Dis Senegalese singer, songwriter, actor, business man and politician, describe im sef for 2004 to tori pipo Roliing Stone magazine as ""maybe di most famous singer wey dey alive."" Im serve as Senegal Minister for tourism from 2012 to 2013. Youssou N'Dour act for award winning feem wey dem dey call Return of Goree. Sauti Sol na Kenya afro-pop band wey base for Nairobi. Dem first start as alcapella group for 2005 before dem turn band. Di band don do many local and international tours and em popular for home and abroad. Sauti Sol don pack may different awards including Kisima Music Awards, Channel O Music Video Awards, MTV Europe Music Awards, and the BET Awards. Award winning Nigerian singer Innocent Idibia aka 2Face say ""dis one pass Grammy"". While Sean Diddy Combs call am ""di album of di year"". See tweets of some of di reactions." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53774884 +health """Vaccine"" in Ghana: Covid-19 AstraZeneca vaccine plus how you go fit get your vaccination in Ghana" Since de introduction of Covid-19 vaccination for Ghana last week, Ghana Health Service (GHS) say 162,541 people take de AstraZeneca vaccine. According to de GHS out of dis number 82,601 be men wey 79,940 be women. So how Ghana dey roll out de vaccines and who dey qualify for de vaccination? De first phase of de vaccine dey cover three major regions where de country record more Covid-19 cases. Greater Accra, Ashanti den Central region which record de highest cases of de virus go get de vaccination first. Since March 2, Greater Accra Region record de highest number of vaccinations with 104,174, den for Ashanti Region some 55,141 people take de vaccine, while Central Region get 3,226 people who take am. According to de Ghana Health Service, everyone from de age of 18 years and above go fit go for de vaccine. Health Officials start dey vaccination on March 2, 2021 where dem target frontline workers, Members of Parliament, key state institutions den security services. But at dis stage dem open de vaccination up to de general public for Ghana. What you need to know before going for de vaccine? GHS Officials advice say interested people for come along plus any recognised national ID card like Voters ID, NHIS card, Ghana Card den tins. Govment advertise say dem dey start dey vaccine for some 25 districts within Greater Accra, 16 districts for Ashanti and finally 2 districts for Central region of Ghana. Dis be de first areas where vaccination go happen, later on dem go open up to other parts of de country. For every individual who dey take de AstraZeneca vaccine, dem go take two shots in total. Medical officers dey administer de first shot, after which dem go give another date for people to come for dema second shot. Housekeeping rules on how to prepare for de vaccine Officials advise de public say before one go come take de vaccine, dem for make sure sau dem eat well. Some people dey get minor reactions like headaches and dizziness if dem no eat well before taking de vaccine. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56317471 +entertainment See how Sarkodie and Yemi Alade take settle dia two years quarrel "Ghanaian rapper, Sarkodie and Nigerian singer Yemi Alade don begin dey patch dia relationship afta afta tins fall apart between dem two years ago. Yesterday, Sarkodie tweet say make Yemi Alade follow am back on Twitter and di Nigeria singer agree. Dis two ogbonge African bin get quanta for 2017 wen Yemi Alade feature Sarkodie for her song ""Ego"" and e no show up for di video shoot of di song. Alade come para and accuse Sarkodie say im dey unprofessional and since den di two of dem no too dey yarn with each oda until now. Sarkodie na im first call for peace afta e share for twitter di new song wey Alade and Beninese singer Angélique Kidjo sing togeda. Yemi Alade come later thank am and di rapper come ask her to follow back for Twitter. Di artists coming back togeda as friends lead to happiness for many of dia fans as dem begin tweet concerning dis." https://www.bbc.com/pidgin/world-51417900 +sports Messi: Barcelona say Argentina forward Lionel Messi go leave di club "Barcelona say Lionel Messi no go stay for di club ""because of financial and structural obstacles"". Messi, 34, don be free agent since 1 July wen e contract expire. Im agree new deal on reduced wages with di club two weeks later, but e bin dey dependent on Barca selling players to afford e salary. ""Both parties deeply regret di wishes of di player and di club go ultimately no dey fulfilled,"" di club tok. Barcelona say Messi bin dey ready to extend e 21-year career wit di club by signing di deal on Thursday, but blame La Liga for failing to do so. ""Despite say FC Barcelona and Lionel Messi bin reach agreement and di clear intention of both parties to sign new contract today, dis no fit happun because of financial and structural obstacles (Spanish La Liga regulations),"" di club tok. ""FC Barcelona wholeheartedly express dia gratitude to di player for e contribution to di aggrandisement of di club and wish am all di very best for di future for im personal and professional life."" Messi na Barcelona record scorer wit 672 goals and e win 10 La Liga titles, four Champions Leagues and seven Copa del Reys, as well as six Ballon d'Or wey im don win. Keeping Messi for Nou Camp bin be president Joan Laporta top priority dis summer. Di Barca future of di player wey dey widely regarded as being one of di world's greatest of all time, however, don dey really complicated by di club financial problems. Di presidential election earlier dis year hold for time wey be say Barca bin dey on di verge of bankruptcy. Di Argentine arguably now become di most in-demand player for world football. For long, Messi don dey linked with move to either Paris St-Germain or Manchester City, wia im go reunite wit e former Barcelona boss Pep Guardiola. America Major League Soccer, wey Messi don previously consider say im go like experience, na another option." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58108340 +sports Manchester City vs Paris St-Germain prediction: UEFA Champions League Group A preview "Manchester City vs Paris Saint Germain for di Etihad Stadium na one of di big games on match day-five of UEFA Champions League on Wednesday. Four-time Champions League winner Sergio Ramos fit make im first appearance for Paris St-Germain against Manchester City. Sergio Ramos wey dey 35 years neva play for im new club since im comot from Real Madrid. Him just dey recover from calf injury but im follow di squad travel to Manchester for di ogbonge UEFA Champions League Group A match. Manchester City go qualify for di round of 16 if PSG no beat dem. Also, if Club Brugge no win RB Leipzig for di oda match inside Group A, Pep Guardiola team go enta di last 16. 'Past results no dey important', na PSG Coach Mauricio Pochettino yan. Pochettino ginger PSG to 2-0 win against City for Parc des Princes inside September, even though di group don change wit City ontop. Now dem (PSG) just need only one point from dia second game to qualify. Pochettino also ginger Tottenham Champions League quarter-final win ova City for 2019. Pep Guardiola tok say e past meetings wit di Argentine no go get any meaning for dia clash dis evening. ""E dey completely different - different kontris, players, shapes,"" Guardiola tok ""Even wit di same manager and same team from one year e fit dey different - new players, many tins fit happun."" Manchester City vs PSG: Team news City go check on record signing Jack Grealish bifor di game go start. Di England midfielder miss Sunday Premier League victory ova Everton wit one knock wey im get from international duty, but im dey hope to return early bifor match start PSG. Kevin de Bruyne sef dey sick wit coronavirus so im no go play. Manchester City vs PSG: Head to Head (H2H) Lionel Messi wey dey play for PSG don score seven goals inside seven Champions League matches against Manchester City. Manchester City's Joao Cancelo don dey directly involved wit five goals for im past four Champions League appearances for Manchester City (two goals and three assists against Club Brugge.) Paris St-Germain don only win 20% of dia meetings wit Manchester City for di Champions League. PSG neva win any of dia last three Champions League matches wey dem no play for home. And e fit go witout an away victory inside di group stage of di competition for one single season, di first time since 2004-05. Manchester City vs PSG predictions Some sports writers and footboll pundits don drop dia predicts for di match dem. Sports Analyst Uche Nwudoh say Manchester City go beat PSG 2-1 wey Olujide Olusola say Manchester City go lose for dia house, 1-2 to PSG Busayo Olowookere predict say Mancity go win PSG 3-1 and Liverpool go win Porto 2-1" https://www.bbc.com/pidgin/sport-59393209