diff --git "a/data/pcm/test.tsv" "b/data/pcm/test.tsv" new file mode 100644--- /dev/null +++ "b/data/pcm/test.tsv" @@ -0,0 +1,306 @@ +category headline text url +business Transport fares for Ghana shoot up by 10% starting today "Transport fares for Ghana go up today y 10% after Ghana Private Road Transport Union (GPRTU) increase transport fares across de country. De transport fares which dey take effect from today, September 16, 2019 go affect commercial vehicles like trotro, taxi den long distance transport vehicles. Ministry of Transport last week approve de proposed increments after proposal from Ghana Private Road Transport Union (GPRTU) den Ghana Road Transport Coordinating Council. GPRTU say dem increase transport fares sake of de things wey dem dey need take run commercial transport services like petroleum den tins go up. Despite fears say de transport price increase go affect price of goods den services, President of Ghana Union of Traders Association (GUTA), Dr. Joseph Obeng say dem no go increase price of goods. But for low income earners de increment go put pressure on dema salary wey small already. ""Now from Labone to Tema station be GHC2.00 but now e be GHC2.20 pesewas. If I calculate for de month my salary no go be not be enough for my expenses"" Musa Ibrahim, a steel bender told the BBC. De last time transport fares go up for Ghana be around June 2018. Dem increased am by 10 percent." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49712534 +business Pound fall to all-time low against dollar - Experts explain di implication "Di pound don make record as e fall to a record low against di dollar as markets dey react to UK biggest tax cuts in 50 years. For early Asia trade, di sterling slip just below $1.04 - di lowest level since decimalisation for 1971 - before e regain some ground to about $1.05. Dis wan happun afta Chancellor Kwasi Kwarteng unveil historic tax cuts wey dey funded by di big increases in borrowing. Di pound bin also dey under pressure as di dollar get boost by di US central bank wey continue to raise rates. Di euro also touch a fresh 20-year-low against di dollar for morning Asia trade sake of investor concerns about di risk of recession as winter dey near with no sign of an end to di energy crisis or di war for Ukraine. If di pound stay for dis low level against di dollar, imports of commodities wey dem dey price for dollars, including oil and gas, go dey more costly. Oda goods from di US fit also dey considerably more expensive and British tourists wey dey visit America go see say dia holiday money no go go as far as before di sterling fall. Investors go dey watch di pound movements closely as financial markets open for di UK, Europe - and later on Monday - di US. Peter Escho, di co-founder of investment firm Wealthi, say: ""All currencies dey sell off against di US dollar, so e get big element of US dollar strength. But wit di pound, e don really worsen by news say di new goment go dey cut taxes, wey fit mean inflation. ""Add to dat, di recent energy subsidies and news say di Bank of England fit need to get emergency rate-hike meeting, e all go result in a sense of panic,"" e add. Some investors tink say di Bank of England go dey forced to take emergency action to stop di pound fall. ""To stop di bleeding even temporarily, di BOE fit enta 'whatever it takes' territory to bring inflation down. Emergency meeting rate hike cfit happun as soon as dis week to regain credibility for di market. We fit even see a hike today,"" Stephen Innes, managing partner for SPI Asset Management tell BBC. Di pound fall in response to di UK goment huge tax cutting mini-budget. Jane Foley, oner currency strategist for Rabobank, say di sell-off show say investors get doubts about di goment plans. ""Dem dey worried say some of dis tax cuts wey dem don announce no go dey fully funded. E go result in a large amount of debt at a time wen di Bank of England go dey sell some of im holdings of UK goment debt,"" she tok. Di pound bin already dey slide against di dollar in di weeks before di mini-Budget, partly sake of di strength of di US dollar. E bin dey trading at $1.135 earlier for September - di first time e bin fall below di $1.14 mark in nearly four decades. Di trend na sake of rising prices and rising energy costs wey don continue to squeeze pipo accounts. Di cost of living dey rise at its fastest rate in 40 years, with food, fuel and energy prices wey all done go up. Dis year, di pound don fall more against di dollar dan oda currencies. Na di worst annual fall against di dollar since Britain vote to comot European Union (EU) for June 2016." https://www.bbc.com/pidgin/world-63030899 +business Nigeria inflation rise to 19.64%, expert tok wetin e mean for Nigerians "Nigeria inflation rate for di month of July 2022 rise to 19.64%, di National Bureau of Statistics (NBS). Dis na di highest since 2005 – dat na 17 years ago. E high pass wetin di kontri record for di of month June wey dey for 18.6%. Di latest inflation data na according to di Consumer Price Index (CPI) wey NBS release. But one sabi pesin for issues wey concern economy say Nigeria dey inside problem wit di report by NBS. Dr. Muda Yusuf, Chief Executive Officer of Centre for di Promotion of Private Enterprise say di summary of di inflation na say di cost of living don high. E say say pipo wey poor go poor more sake of “severity of food inflation.” Di sabi pesin say di essence of di NBS report na for pipo to know say di situation for Nigeria no make sense. “Prices of food don double in di last one. You know how e dey be wen pipo dey struggle to chop. “Di 19.64% summarise di situation say tins bad well well,” e tok. Oga Yusuf add say, “Di situation dey extremely bad. Many pipo no fit feed well sake of di food inflation. Di implication of dis new inflation dey very serious and “severe”, di sabi pesin tok. Chief Executive Officer of Centre for di Promotion of Private Enterprise list some of di cause of di failure of di economy. “You know wetin e mean wen pipo dey struggle to eat."" E explain say, “Insecurity don make am hard for pipo to go farm. Di pipo wey dey produce wetin we dey chop dey IDP camps sake of attacks. Di energy cost na wen producers dey spend plenty money to produce wetin pipo dey chop or use. Price of diesel, gas and aviation fuel. “Exchange rate na anoda mata wia we don see wia naira no get value again.” Dr. Muda Yusuf say goment need to chook eye inside di economic situation. “E no be like say goment dey do any tin. Di head of di economic team wey di Vice president dey lead. Even di oga of di board Doyin Salami just dey dia like.” E say goment only need to listen to wetin di experts wey dey im team advice am to do before solution go come. “Make goment gada pipo wey unsaderstand di issue. No be theoretical matter. I no sure di president sabi wetin dey happun. Nigeria get pipo wey sabi economy mata wey fit find solution to dis problem.” Di sabi pesin say to begin address di problem, Nigeria must first solve di problem of insecurity." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c10v2qq2l09o +business Five tins to know about Nigeria new naira notes design Nigerians still dey react afta goment unveil di new naira notes dem redesign. Some say di new design of ₦200, ₦500,and ₦1000 naira notes wey President, Muhammadu Buhari just launch resemble di old one. Na Wednesday, 23 November President Buhari tear rubber di three new designs for Abuja. Dis na di first time in 19 years di kontri dey redesign her currency notes. Goment release foto of di new naira notes few weeks afta Central Bank bin announce say dem go change di design. President Buhari say di new naira notes go improve di economy and help address financial mago-mago dem. From di foto wey goment release, di new ₦200, ₦500,and ₦1000 naira notes resemble di old one. But di major physical difference na say CBN change di colour of di new notes. Goment say dem boost di security features for di new naira to secure di money. Dem say dis security features go make am hard for pipo to counterfeit. CBN no change di foto dem for di new notes. Dem still use di same face of di pipo wey bin dey di old naira note for dis new one. Di ₦200 note face still be Alhaji Sir Ahmadu Bello, - dI Sarduana of Sokoto and Di first Premier of Northern Nigeria. Di face wey dey di new ₦500, still be Dr. Nnamdi Azikiwe - first President of Federal Republic of Nigeria And for ₦1000, na still Alhaji Aliyu Mai Bornu and Dr. Clement Isong – Dem be di first and second indigenous Govnors of Central Bank of Nigeria. President Buhari say dem go produce di new naira bank notes locally. Buhari say na Nigerian Security Printing and Minting (NSPM) PLC go design di new naira notes. E say di new banknotes go help di Central Bank design and implement beta monetary policy objectives as well as enrich Nigeria heritage. Di new naira notes go dey in circulation from December 15, 2022. CBN say, di new and old currencies go still dey in use as dem go dey in circulation togeda until January 31, 2023. Meanwhile, oda notes like ₦5, ₦10, ₦20 and ₦50 still dey valid afta di January 31 deadline. Dem dey valid because goment no change di design of di lower currency wey be polymer notes. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c80g4n9wx1vo +business Dubai: How Russians billionaires and business man dey run go Dubai to avoid sanctions "Dubai don become di safe place for wealthy Russians wey dey dodge di impact of western sanctions wey dem impose ova di war for Ukraine. Plenti Russian billionaires and entrepreneurs na im don land United Arab Emirates (UAE), business leaders tell BBC. Property wey Russians dey buy for Dubai don rise by 67% for di first three months of 2022, one report tok. Di UAE neva put sanctions on Russia or criticise dia invasion of Ukraine. Dem dey also provide visas to non-sanctioned Russians while many Western kontris don restrict dem. Di estimate be say hundreds of thousands of pipo don leave Russia ova di last two months - although di exact figures no dey available. One Russian economist tok say as many as 200,000 don leave for di first 10 days afta di war begin. Virtuzone, wey dey help companies to set up operations for Dubai, don get plenti of Russian clients. ""We dey receive five times more enquiries from Russians since di war begin,"" chief executive George Hojeige tok. ""Dem dey worried about one economic meltdown wey dey come. Dat na why dem dey move here to secure dia wealth,"" e add. Di coming of Russian nationals don ginger demand for luxury villas and apartments across di city. Real estate agents dey report increase in property prices, as Russians wey dey land Dubai dey look for home to buy. Dubai-based real estate agency Betterhomes find out say property wey Russians buy increase by by two thirds in di first three months of 2022. And anoda real estate agency, Modern Living, tell di BBC say dem don hire many Russian-speaking agents to cater to rising demand. Chief executive Thiago Caldas tok say dem dey receive plenti calls from Russian nationals wey dey look forward to relocate to Dubai immediately. ""Russians wey dey come down no dey buy just for investment, dem dey look Dubai as second home,"" e tok. Many multinational companies and Russian start-ups also dey relocate dia employees to di UAE. Fuad Fatullev na di co-founder of WeWay - one blockchain technology company wey get offices for Russia and Ukraine. Afta di war break out, im an e partners shift hundreds of employees go Dubai. ""Di war get massive impact on our operations. We no fit continue [as we bin dey] as we gatz to move hundreds of pipo outside of Ukraine and Russia,"" Fuad, wey be Russian citizen tok. E add say dem choose to shift dia employees go di UAE as dat place offer safe economic and political environment to operate business. E say Russian businesses dey move out as dem dey find am seriously difficult to operate due to sanctions. Di challenge dey even more serious for companies wey dey deal with international clients and brands, as most western firms don cut ties with Russian-based enterprises, e tok. Global firms like Goldman Sachs, JP Morgan and Google wey don shut down offices for Russia, dey also relocate some of dia employees to Dubai. ""Truly brain drain dey happun. A lot of pipo dey leave because a lot of business restrictions dey right now,"" Mr Fatulley tok. Russia central bank dey banned from tapping into di billions of foreign reserves wey dey overseas for foreign banks. Some Russian banks dey removed from di Swift financial messaging system. To protect dia reserves, di Russian goment don enact capital restrictions and ban citizens from leaving di kontri with more than $10,000 in foreign currency. Due to how difficult e be to transfer cash, plenti Russian buyers dey make payments in cryptocurrencies. Some of di purchasers get intermediary wey go take di payment in crypto and den pass on di cash to di seller on behalf of di buyer. Gulf states including di UAE and Saudi Arabia don reject calls from western goments to impose sanctions on Russia. Di UAE na one of only three kontris, along with China and India, wey no join one United Nations Security Council vote for February to condemn Russia invasion of Ukraine. Dem also no join for one General Assembly vote on 7 April to suspend Russia from di UN Human Rights Council. Di rise in Russian investment dey come just months afta di UAE dey placed on one ""grey list"" by di Financial Action Task Force (FATF), wey be one global financial crime watchdog. E means say di kontri dey face increase monitoring of dia efforts to counter money laundering and terrorist financing. Di UAE goment claim say dem don take significant measures to regulate inbound investment, and state say dem remain committed to work closely with FATF on areas for improvement." https://www.bbc.com/pidgin/world-61339313 +business Marwako apologize to customers for Ghana wey suffer food poisoning after dem patronize dema restaurant "Fast food company for Ghana, Marwako extend apologies to customers wey suffer food poisoning after dem patronize dema food. After initial inquiry into de complaints, de fast food company say dem identify about 53 people wey fall victim to food poisoning. Food and Drugs Authority (FDA) shut some of dia branches down over alleged food poisoning allegations after some Twitter users call de Company out on top social media. Spokesperson, Mohammed Amin Lamptey explain say ""de main tin start on Saturday den Sunday evening. We accept everything, we apologize to de victims."" He add say dem also reach out to de victims to support dem and pay for some of dia medical bills. Food and Drugs Authority for Ghana shut down three branches of de fast food chain after social media reports emerge say some customers including kids experience food poisoning. Although de incident happen for dema East Legon branch, de FDA say dem shut de East Legon branch and two other branches which no dey adhere to good kitchen den storage practice. According to FDA, ""we go investigate dis matter well-well den make sure say we take appropriate actions. One Twitter user after reporting to de hospital for stomach pains reveal say en troubles start after he eat for Marwako. After dis tweet, more Twitter users come out to explain dema own experience with food poisoning and diarrhoea. After dis tweet, more Twitter users come out to explain dema own experience with food poisoning and diarrhoea." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61434202 +business Why Elon Musk dey pull out of $44bn deal to buy Twitter "Elon Musk wan end im $44bn (£36bn) offer to buy Twitter, im dey allege breach of di agreement. Dis announcement na di latest twist ontop dis mata afta di world richest man bin decide to buy di microblogging site in April 2022. Musk say im dey back out because Twitter fail to provide enough information on di number of spam and fake accounts. Twitter dey plan to use legal action to enforce di agreement. ""Twitter Board dey committed to close di transaction for di price and terms wey Oga Musk bin agree,"" Twitter chairman Bret Taylor write for tweet. As tins be, e fit set up long legal battle between di two sides. Di original merger agreement include $1bn (£830m) break-up fee. Na for May, Oga Musk bin tok say di deal dey ""temporarily on hold"" onto say e dey wait for data on di number of fake and spam accounts on Twitter. Di billionaire businessman bin don ask for evidence to back di company claim say spam and bot accounts make up less than 5% of dia total users. For one letter wey im file wit di US Securities and Exchange Commission, Oga Musk lawyer say Twitter don fail or refuse to provide dis information. ""Sometimes Twitter dey ignore oga Musk requests, sometimes e dey reject dem for reasons wey dey unjustified... ""...and sometimes dem dey claim to comply to givie oga Musk informate wey no dey complete or informate wey e no fit use,"" di letter tok. Tori be say spam accounts dey designed to spread information to large numbers of pipo and manipulate di way dem dey interact wit di platform. On Thursday, Twitter say dem dey remove around 1 million of dat kain account every day. Oga Musk believe say spam or bot accounts fit account for 20% or more of Twitter users. Shares for Twitter bin fall by 7% in extended trading afta di announcement. Elon Musk don dey try for weeks to get informate about how many daily active users Twitter get. Twitter get problem wit bots alias fake accounts. In fact only on Thursday dem say dem remove one million spam accounts a day. For im filing, oga Musk say dem refuse to give am informate about di number of bot accounts on Twitter – dat na why im wan terminate di deal. Although Elon Musk don already put pen to paper on top dis deal, and e no dey clear whether im fit back out at dis stage. Oga Musk go need to prove say Twitter break dia agreement. E get oda reasons wey fit don make Oga Musk to pull out of di deal. Di stock market price for large tech companies don fall well in the last few months – another tin na whether Oga Musk offer too much? And then di impact di potential merger get on Oga Musk oda companies. Tesla share price don fall well-well since im announce im interest for Twitter. Im position on free speech and how Twitter fit moderate for future - base on di laws of individual kontries - at times dey naïve. A bi Elon Musk reason am say dis tin fit don cast? Oga Musk, na di world richest pesin, di founder of rocket company SpaceX and electric car company Tesla. Im bin criticise Twitter ban of some accounts, like dat of former US President Donald Trump. Him also call for more transparency ova how di platform dey present tweets to users, one system wey currently dey allow some to dey promoted to get wider audiences." https://www.bbc.com/pidgin/articles/ce7nke4lkwno +business E-levy Ghana: Ghanaians hit streets of Accra to protest against electronic transactions tax wey govment wan introduce Protestors for Ghana hit de streets of Accra to register dia displeasure wit new electronic transactions tax wey govment wan introduce Dem also dey protest against fuel price increases, high cost of living, corruption den stuff. Members of de Coalition of Concerned Ghanaians (CCG) who dey lead de 'Yentua' demonstration say dem no go pay de e-Levy government wan introduce. De controversial 1.75% Electronic Transfer Levy on mobile money transactions dey face strong opposition since last year when govment announce plans to introduce am. Representatives of de opposition NDC, other political parties, Civil Society Organisations den other identifiable groups dey lead de protest. De electronic transactions levy be new tax wey govment wan introduce on mobile money transactions for Ghana. Finance Minister, Ken Ofori-Atta announce details of de new tax during de budget statement for 2022. Govment introduce 1.75% tax on all mobile money transactions which dey exceed Ghc100. But most Ghanaians reject dis new levy sake of dem say e dey create more hardships for citizens who already dey suffer. Minority in Parliament, support de calls of ordinary Ghanaians to reject dis proposed levy, sake of that dem reject de 2022 budget. However, de majority lawmakers manage pass de budget later on when presiding speaker, Joe Osei-Owusu chair sittings in de absence of de Speaker who travel to medical care. Despite all of dis, lawmakers raise objection to de e-levy which per rules of de house dem for vote on. In attempts to take de e-levy under certificate of emergency so say dem go fit vote on am and pass am into law, de fight break out. Parliament last year push de debate of e-Levy to dis year after dem reach no consensus on de matter. Ghanaians wey dey opposed to de e-Levy dey continue plus dia calls for govment to reverse de plans to introduce de e-levy. https://www.bbc.com/pidgin/media-60329635 +business Ecowas lift economic punishment on Mali, Burkina Faso, warn Guinea Leaders from West Africa Regional bloc, Ecowas, don lift economic and financial punishment aias sanctions dem put on Mali. Na after Mali military rulers plan to hold elections and returning di kontri to civilian rule by March 2024. ECOWAS Commission President Jean Brou tell tori pipo on Sunday say di lifting of di sanctions na wit immediate effect. Di bloc bin put tight sanctions on Mali in January dis year following di military leaders strong-head for a timetable to return to civilian rule. However, individual sanctions targeting members of Mali ruling military leaders go dey maintained. Same tin apply to di transitional council until di return to democratic rule. Ecowas - Economic Community of West African States na join bodi of kontris inside di region. Di bloc dey normally monitor political, security and humanitarian situations for di west Africa region. Ecowas also accept a two-year timetable for di restoration of democracy in Burkina Faso. Economic and financial sanctions imposed on di kontri also dey lifted. As for Guinea, Ecowas commission president Jean Claude Kassi Brou say Guinea junta don beg to propose a new timeline by end of July, or face economic sanctions. Di three kontris dey suspended from Ecowas due to military coups. Ghana host di 61st Ordinary Session of di Authority of di ECOWAS Heads of State in Accra today. Dis Session bring to an end di second-year leadership of President Nana Akufo-Addo as ECOWAS Chair. Sunday meeting of di regional bloc hold for Kempinski Hotel, Accra. E dey dedicated to examining and taking decisions on di political, security and humanitarian situations for di west Africa region. President Akufo-Addo take up di Chairmanship of ECOWAS on September 7, 2020 inside Niamey, Niger. Dat na after Mahamadou Issoufou, former President of Niger, end im tenure. In June, 2021, di Ghanaian leader mandate bin dey renewed for anoda one year. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c72155e9g5eo +business Visa cryptocurrency: How to make payment wit cryptocurrency from your Visa card "Visa Inc tok on Monday say e go allow di use of di cryptocurrency USD Coin to settle transactions on dia payment network. Dis move na di latest sign of growing acceptance of digital currencies by di mainstream financial industry. Di company tell tori pipo for Reuters say e don launch di pilot program wit payment and crypto platform Crypto.com Dem tok say dem get plans to offer di option to more partners later in di year. Crypto.com say dis na historic moment to successfully conduct di first settlement of transactions using USDC. Di USD Coin (USDC) na one stablecoin cryptocurrency wey dem don peg di value directly to di U.S. dollar. Traditionally, if one customer choose to use a Crypto.com Visa card to pay for anything, dem go first convert di digital currency wey dey in cryptocurrency wallet to traditional money. But now, di cryptocurrency wallet go deposit traditional fiat currency inside one bank account, dem go come later wire am to Visa at di end of di day to settle any transactions, and dem go add cost and complexity for businesses. Visa latest step, wey go use di ethereum blockchain, go comot di need to convert digital coin into traditional money in order to settle any tansaction. Visa say dem don partner wit digital asset bank Anchorage and complete di first transaction dis month — wit Crypto.com sending USDC to Visa Ethereum address for Anchorage. Dis Visa move dey come as finance companies including BNY Mellon, BlackRock Inc and Mastercard Inc dey take steps to use more of cryptocurrencies for investment and payment purpose. Tesla Inc boss Elon Musk, wey be ogbonge advocate of cryptocurrencies, tok last week say customers fit buy im electric cars wit bitcoin, dey hope to encourage more day-to- day use of di digital currency. ""We see increasing demand from consumers across di world to be able to access, hold and use digital currencies and we dey see demand from our clients to be able to build products wey dey provide dat access for consumers,"" Cuy Sheffield, head of crypto for Visa, tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56567221 +business Nigeria vs Ghana 'trade war' plus harassment wey Ghanaians dey show Nigerian traders and wetin we know so far Nigeria vs Ghana situation don enta 'delicate stage', na wetin Nigeria foreign minister Geoffrey Onyema tell BBC Pidgin ontop di trade relations wey don tour sour between di two west African nations. Now, House of Representatives Speaker Femi Gbajabiamila, Nigeria number four man dey visit Ghana today inside di middle of di trade war. Gbajabiamila waka na one of di ways to find solution to di $1million levy wey Ghana sama Nigeria traders for dia kontri. Last week Nigeria para say dem no go accept how Ghana dey humiliate Nigeria. But Ghana authorities say no be so di mata be. Tori be say, both kontries never address di mata again for public, since afta Lai Mohammed, Nigeria information minister cut 'enough is enough' warning for Ghana and wen im colleague for di Gold Coast Kojo Oppong Nkrumah reply say President Nana Akufo-Addo go discuss wit Nigeria President Muhammadu Buhari to solve di mata peacefully. But at di moment Nigeria vs Ghana situation don damage? Recently, Ghana authority close more than two hundred shops wey belong to Nigerians sake of say dem no follow dia trade regulation plus dem neva pay dia 1million dollars levy. Ghana say dem no want make foreigners enta into retail business as dem reserve dat sector for dia citizens but Nigeria say dat one dey against ecowas protocol. Since Ghana and Nigeria get dia independence, diplomatic relations between di two kontris always get gbege. Di two kontris dey always wan prove who beta pass in terms politics, economy, sports, and regional integration. Even citizens of di two kontris dey drag demselves on top who jallof rice sweet pass- dis wan show di kain rivalry wey don dey between di two kontris. However, di recent way wey some jaguda pipo demolish Nigrian embassy building for Ghana and di closing of Nigerian retail shops don cause high diplomatic tension between di two kontries. While di goment of both kontris still dey try find diplomatic solution to di mata, dis na di genesis of how Nigeria and Ghana fight -fight take start. • Pre-colonial Era: Di first gbas gbos between Nigeria and Ghana start for 1931. • During dis period, di number of Nigerians wey di live for Ghana reach like 20 percent of di kontri population. • Many Nigerians dia bin di work as Cocoa farmers, business pipo, labourers and becos Ghana economy bin good, dia business bin dey boom. • But later during di cocoa hold-up saga for Akyem Abuakwa area, di king and di traditional council bin ask di colonial goment make dem deport Nigerians wey be trouble makers. Independence Era: Ghana get im independence for 1957 and di head of gonment den be Kwame Nkrumah At dis time, di population of Nigerians and di business community don grow for Ghana. Even for dis era, Ghanaian pipo kontinu to mount pressure on top dia goment head to deport Nigerians wey dem refer to as alien. For August 23 1957, di Convention Peoples' Party (CPP) government passed the Deportation Act wey give goment right to deport those wey dem consider as threat to dia kontri During dis period some Nigerians chop deportation and goment describe dem say dem be opposition party members. Deportation act of 1969: Dis period mark di major deportation of aliens or foreigners dem from Ghana. Close to 200,000 pipo from Togo, Mali, Burkina Faso, and Nigeria bin pack dia kaya waka from di kontri. Sake of dis deportation, many African kontri begin target Ghanaian pipo dem for dia kontri and begin ask dem make dem leave. Ghana must go: During di period of 1986, Nigeria presido den, Shehu Shagari ask Ghanaians make dem pack dia load and leave di kontri. Many of dem bin dey Nigeria to find beta life sef come do dem back, as e ask Ghana pipo to also leave Nigeria. Di reason Ghana bin deport plenti pipo wey dem refer as alliens from dia kontri na to provide beta job opportunities for dia citizens. And to also allow dia pipo to get more involved for di kontri economy as foreigners dem bin get business ground for di kontri pass. Na from since 1931 na im Ghanaians dey try put pressure on dia goment to drive oda nationalities and today, di situation neva change as Ghana business pipo kontinu to ask dia goment to do dey needful Prof. Bola Akintehinwa wey be former DG of NIIA, say some Some Ghana business pipo dey vex on top how Nigerian traders dey sell dia kaya cheap wit chikili moni Some times di Nigerian traders dey even cari more quality goods. Sake of dis, dey business men dey always lobby different goment to put dowm laws wey go favour dem against Nigerians. Di kasala between Nigerian traders and di Ghana authority fit cause major k-leg for Nigeria/Ghana diplomatic relations. Since di gbege, mani Nigerians don call on di goment to also fine Ghanaians di same amount and close dia shops to teach Ghana lesson But oga Bola say why Ghana di try project dia National interest, Nigerian goment no dey do anything. And dat di best tin to do now na for di Nigerian president, Muhammadu Buhari to try call Ghana president and warn am against wetin e dey do And tell am say Nigeria also get power to retaliate. E say do-me -I do you approach no go epp for dis mata and dat both kontris gatz look for diplomatic way to resolve dia wahala. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53994995 +business CBN increase interest rates: Central bank MPR explainer Central Bank of Nigeria (CBN), Monetary Policy Committee don approve new Monetary Policy Rate (MPR) of 13 per cent. CBN governor, Godwin Emefiele, say na six out of eleven of di committee members vote to raise di rate. Monetary Policy Rate na rate wey Central Banks for different kontris dey use control di availability of assets wey pipo fit convert to cash. If Monetary Policy Rate (MPR) rise, all di oda rates go go up, and if e drop, all di rates go drop. Nigeria bin peg interest rate for 11.5 per cent for over two years. But now, wit di new MPR review, e don jerk up to 13 per cent to manage di rising inflation. By dis increase, CBN don give Deposit Money Banks go ahead to increase lending rates to possibly dey higher dan deposit rates. Banks dey also use am to determine fixed deposit rates and normal savings rates on accounts. Although, dis new monetary rates fit affect businesses for manufacturers and exporters wey wan collect loans, di positive side be say e go fit help slow down inflation. Interest rate na one of di key tools deployed by central banks across di world to manage di flow of money and productivity for kontris. A change in interest rate fit affect macroeconomics and other key economic indicators like consumer spending and borrowing. For Nigeria, di tool allow di CBN to effect changes in broad monetary policies wey dey designed to facilitate di goment budget policy. By hiking the interest rate to 13%, e dey expected say borrowing go become more difficult. And consumers fit get less money to spend. By implication, e mean say even inside lower demand among consumers, manufacturers of goods go dey concerned about raising prices. In effect, all of these go sha combine to reduce inflation pressure. But di hike go still also fail to stop inflation if other macroeconomic indicators go wrong. When di CBN interest rates bin dey for 11.5 per cent, banks typically charge manufacturers and oda lenders between 12 to 30 per cent on loans. With di hike in rate (13%), di charges fit high like wen water don pass garri. Earlier in the year, di Manufacturers Association of Nigeria bin tok say average rate dia members dey borrow money from banks bin dey between 20.75 per cent. E bin stand at 21.25 per cent in 2020 and 2019. In terms of job creation, a hike in interest rate fit get effect—if marginal—on di number of jobs wey dem create or lost. Unemployment Rate in Nigeria don averaged for13.55 percent from 2006 until 2020. Dat time e climbing to an all-time high of 33.30 percent inside di fourth quarter of 2020. Even if di impact fit no dey significant in di immediate, di hike in interest rate and possible fall in productivity fit throw a number of pipo out of jobs. Normally, low interest rates fit cause di stock market to go up. Just as di market dey record depreciation wen di apex bank raise interest rates. By implication, change in central banks interest rates dey affect prices of various assets such as bonds, stocks and houses. https://www.bbc.com/pidgin/media-60378409 +business Bread price in Nigeria: Why loaf of bread fit increase? "E be like say di price of bread for Nigeria go soon increase sake of rising production costs. Bakers under di Premium Breadmakers Association of Nigeria (PBAN) tok say dem wan increase di price of bread so dem no go shut down dia operations. President of PBAN Emmanuel Onuorah tell BBC Pidhin say dis na sake of di high cost of diesel and di fact say materials wey dem dey use produce di bread also don drastically increase. E say dis factors don already make some bakers close dia businesses. ""Many members don close down or sack workers because dem no fit meet up again. Our business dey face loss."" Onuorah say before di Covid-19 pandemic, flour na between N8000 to N10,300 per bag but now na about N22,500. Sugar before na N13,000 now N23,500 and dem still dey threaten say di price go still increase. Softener wey dem dey take make di bread soft well well before N300,000 but now na N650,000 while margarine wey be N5800 don be N18,000. Egg wey be N800 per crate now na N2200 as well as oda preservatives d dey use all don increase. ""Di worst tin be say diesel wey we dey use run our vehicle and generator for our ovens dem increase am for N350 to N850 per litre as pipo shout dem reduce am to N650 to N700 so how di business wan be? ""Our capacity don reduce by 50%. Pesin wey dey do 100 nags now e dey do 40 bags or less, yet we dey pay tax and provide our own light and water, which kain tin be dis?"" ""So as e be so, we dey forced now to increase di price so we go remain in business odawise na die we dey and all do investment you don make go just waste,"" Onuorah tok. Onuorah say though dem dey consider di way things be for Nigerians so pipo still fit afford to buy bread, Di increase go follow di different sizes of bread, so di Jumbo size of bread wey be N800 fit increase to N1200 - N1500 and di sliced bread wey be N500 fit increase to N800 Dis na so dat breadmakers go still dey in business as di inflation don drastically reduce dia profit margin. ""If you look at all di increase in di materials, e don reach about 200% increment."" ""Between 2021 and now, we don get material increase of about 155% but we don increase bread price by only 7%."" ""Check di difference in cost of materials and di price of bread, all na make e be say we dey produce bread wey Nigerians fit see bread on top dia table chop."" ""But now things get to change for us to continue di read business,"" e tok. Four things wey go help di bread industry To help di bread making Industry, di PBAN President Emmanuel Onuorah give three things wey go help to include: Onuorah come tell Nigerians to hold goment to account to check di drastic increase in di price of food items as di inflation rate much. E come ask for understanding from di public so dem go adjust to di increase in di cost of bread." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60942819 +business Year of Return attract foreign visitors to Ghana or e be hype? "The Year of Return, 2019, be linked to de 400th anniversary of slaves wey land for US - dem be de the recorded arrival of enslaved Africans for America. Den Ghana be key transit point for transporting slaves and so de president say he dey feel say en country get responsibility, to welcome all those who no fit trace dema ancestry to Africa. ""We believe say we get responsibility to extend a hand of welcome back home to Africans for de diaspora."" President Nana Akufo-Addo tok. So we go fit gauge how successful this initiative be for Ghana? At de beginning of 2019, de Ghana Tourism Authority predict say de Year of Return go attract 500,000 extra visitors. Official data from January to September 2019 dey show additional 237,000 visitors - which be increase of 45% compared with de same period de previous year - more increases of de visitors too come from US den UK. However, we no know if dis be specifically sake of de Year of Return initiative, as dem no ask tourists make dem state on arrival de reason for dema visit. De increase in arrivals in 2019 for dey inside de context of an overall annual total of between 900,000, den one million foreign visitors for Ghana, figure wey dey rise anyway over de past few years, except say e reduce slightly around 2018. When dem publish de data for de whole of 2019, we for fit be able to see how unusual de increase for that year was compared with previous years. Minister of Tourism Barbara Oteng Gyasi talk say de Year of Return inject about $1.9bn (£1.5bn) into de economy. Wey Ghana Tourism Authority talk BBC News say dis figure just be rough estimate, based on multiplying total visitor arrivals, 763,545 between January and September, by the average spend per tourist, $2,590 in 2019. But de total arrivals figure dey include all international visitors, whether or not dema visit be sake of de Year of Return. Bright Simons, researcher for Imani Centre for Policy & Education think tank, criticise government estimates of de numbers of extra visitors. He talk say de average spend per tourist be less than $2,590. De Ghanaian government also talk BBC News say dem grant a record 126 people citizenship in 2019. Wey some from de diaspora, sake of de Year of Return initiative, set up businesses, make investments or buy property. De government also talk say de Year of Return drawn wider attention to Ghana wey e positively influence international media reports. De country attract a number of celebrities in 2019, including model Naomi Campbell, actor Idris Elba, comedian Steve Harvey and American rapper Cardi B. Wey government talk say de equivalent amount of media attention and PR - if like dem dey pay for - go cost about $3.5m. Mr Simons talk BBC News: ""As a public relations den advertising feat, e be very impressive. ""In that sense, I agree say e be success.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51350634 +business Gold mining in Ghana : Di underground waka to find di treasure with one child miner "Alongside di ogbonge gold fields of Ghana, you go see plenti-plenti illegal mines or ""galamsey"" wey unskilled miners dey dig big time to search for gold but dis dia work na dangerous one. All dis mines dey rely mainly on children wey don abandon dia education as dem dey try to support dia families. BBC Africa Eye follow story of Justice Afekey ova di course of eight years from wen im leave school to try and get rich quick, by working for one of dis illegal mines." https://www.bbc.com/pidgin/52350777 +business Budget 2020: President Buhari send 10.33 trillion naira budget based on 7.5% VAT to Nigeria National Assembly Nigeria President Mohammadu Buhari present 10.33 trillion naira as goment 2020 spend money plan to National Assembly on Tuesday. Di capital expenditure for 2020 wey be di money wey di goment plan to spend ontop projects next year dey less than di one inside 2019 budget. Buhari say capital expenditure inside 2020 budget go be 721.33 billion naira wey according to him, be 23% less than di spend mony plan of 2019. Di 2020 Budget go dey based on di new VAT rate of 7.5% according to President Buhari. Na di ministries wey Babatunde Fashola, Saleh Mamman and Chibuike Amaechi dey control as ministers collect di lion shares for di budget breakdown. a. Works and Housing: N262 billion b. Power: N127 billion c. Transportation: N123 billion d. Universal Basic Education Commission: N112 billion e. Defence: N100 billion f. Zonal Intervention Projects: N100 billion g. Agriculture and Rural Development: N83 billion h. Water Resources: N82 billion i. Niger Delta Development Commission: N81 billion j. Education: N48 billion k. Health: N46 billion l. Industry, Trade and Investment: N40 billion m. North East Development Commission: N38 billion n. Interior: N35 billion o. Social Investment Programmes: N30 billion p. Federal Capital Territory: N28 billion q. Niger Delta Affairs Ministry: N24 billion Buhari tell di national assembly say Minister of Finance, Zainab Ahmed, go release details of di 2020 spend money plan later. Di spending plan estimate include statutory transfers of N556.7 alias money wey different arms of goment and agencies dey collect, non-debt recurrent expenditure of N4.88 trillion alias money wey dem got take run goment and N2.14 trillion of capital expenditure billion (wey no get capital component of statutory transfers). Di debt service estimate na N2.45 trillion, and provision for Sinking Fund to retire maturing bonds issued to local contractors is N296 billion. Distinguish Senators, Honourable Members, make I know face di 2020 Appropriation, wey be budget of: a. Fiscal consolidation, to strengthen our macroeconomic environment; b. Investing for critical infrastructure, human capital development and enabling institutions, especially for key job creating sectors; c. Incentivising private sector investment essential to complement the Government's development plans, policies and programmes; and d. Enhancing our social investment programs to further deepen their impact on those marginalised and most vulnerable Nigerians. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49976442 +business Nigerian oil spill: Santa Barbara River spoil wit weeks oil leak from AITEO OML 29 well1 "One oil and gas well wey leak inside Nembe, Bayelsa State, southern Nigeria still dey pour for di pass two weeks afta di oil spill occur. OML-29 Well-1 wey Aiteo Eastern Exploration and Production Company Ltd dey operate don dey pour for more than 14 days none stop. Di oil spill empty into River Santa Barbara for Nember and e don spread near Kula, a coastal community for neighbouring Rivers State. Di spill wey happen sake of alleged equipment failure don pollute rivers, waterways and farmlands. E don affect economic activities, pipo for di local communities wey be mostly fishermen no fit do any fishing activity since di oil spill happen on 5 November, 2021. Tori be say one four-year-old pikin for Nembe dey feared dead from alleged methane gas poisoning as a result of di oil spill. Ekine Japus, di President of Kula Youth Organizations Worldwide tell BBC Pidgin say di oil spill don spread cover di creeks and waterways. And e affect over 10 Kula communities wey include Aberebiya, Barapakama, Angbakiri, Kalawo kiri, New Camp and Inemaboko. Di oil spill also affect Robert kiri, Ofoinama, Belema and Kula main town. ""Since dis oil spill happen, our pipo no fit go fishing because all di water dey polluted. ""Our women sef no fit go pick periwinkle because all di mangroves dey covered wit crude oil from di spill and e dey spread to oda villages. ""Three days ago we go visit di area to see di level of devastation and e dey massive."" Di youth leader tok. ""Evri wia dey smell. We don report to NOSDRA and even write to di oil company AITEO but we never get any response."" E add Ekine Japus tok say ""We also don report to DSS, di local goment council and to di State Ministries of Environment and Local goment affairs."" ""Wetin we want na for dem to stop di spill from di well head as e still dey spill crude oil. ""And for di company to come clean up di area and pay compensation to di pipo because dem no fit do anytin since day time."" Na so Oga Japus conclude. Bayelsa State Goment say dem no happy say weeks after, AITEO Oil Company never do anythin to stop di oil spill for OML 29 Santa Barbara. For statement wey di Commissioner for Information, Orientation and Strategy sign, say: ""AITEO never take any concrete step since 5 November, 2021 wen dem report equipment failure."" Ayibaina Duba come wonder why di oil spill go still dey continue even wen di company dey aware of di situation. ""Make AITEO no assume say we no go hold dem responsible for dis criminal neglect of dia facilities and disregard for human life and environment wey dem don show."" Di statement say make AITEO prepare for di consequences of dis failure as di goment no go stand by and allow dem put human and aquatic live for di encore for danger. Di commissioner come advise pipo wey dey stay for di area to dey peaceful as di goment dey committed to dia wellbeing. AITEO Eastern Exploration and Production Company operator of di NNPC/AITEO Joint Venture on OML 29 don issue statement on dis mata. Media contact for di company Ndiana Matthew on 9 November, 2021 say dem get report of oil spill from a non-producing well head for dia Santa Barbara South field for Nembe local goment area, Bayelsa State. Matthew say di magnitude of di incident dey extremely high and dem never determine di cause of di spill. Or di quantity of hydrocarbons wey leak as at di time of di discovery but say dem don deploy containment booms around di well head. E add. Di statement say dem don report to di National Oil Spill Detection and Response Agency, Nigerian Upstream Regulatory Commission and National Petroleum Investment Services E add say all of dem do joint investigative visit to di spill site wit oda stakeholders, including di community. ""Di JIV dey inconclusive because of difficulties with access due to high pressure of hydrocarbons for di Well head. ""Additionally, we abort immediate efforts to control di leak due to di high pressure wey dey comot from di well head. So AITEO don mobilise full intervention team with Well control specialist and requirements. AITEO bin get license from a consortium of oil majors headed by Royal Dutch Shell Plc in 2015. Di sale price of $2.4 billion for di permit and a pipeline na di largest paid so far by Nigerian companies wey dey buy assets from international companies. Oil spills or leak, particularly from pipelines, dey common inside Niger Delta area of Nigeria wey be Africa's largest oil producer. Experts now dey ready to start di work of sealing di well so that di cause and scale of di leak go fiy dey determined, Idris Musa, director general of Nigeria's National Oil Spill Detection and Reponse Agency, tell Bloomberg tori pipo." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59345863 +business Elon Musk tweet today: Twitter Elon Musk cryptic tweet about death - All we know "World richest man, Elon Musk cryptic tweet about death don make plenti of im followers on twitter dey worried. Elon Musk recent tweets dey go viral afta di Tesla CEO strike one deal to buy Twitter. Dat deal to buy Twitter from di founder, Jack Dorsey dey worth about $44bn. For im bid to buy Twitter, Musk bin promise to reduce censorship on di social media micro blogging site. Elon Musk wey reach one agreement with di board of Twitter to takeover di social media platform weeks ago, tweet give im 91.6M followers say; ""If I die under mysterious circumstances, e dey nice knowing you all."" Dis im tweet don get more than one million likes and thousands of comments, with plenti of im followers wey begin to express concern. Maye Musk, im mama eve dey worried with di tweet and respond with angry face emoji to di billionaire say; ""Dis no dey funny😠😠."" But Musk instantly apologize give im mama say im dey sorry and e go try im best to stay alive. ""Sorry! I go do my best to stay alive."" As many of im follower dey respond to Musk tweet, one request weda di billionaire go hand ova twitter give am if wetin im dey tok happun and Musk reply ""ok."" Here na how anoda tweeter user reply to di Tesla CEO tweet and wetin be im response. Elon Musk dey known to dey crack jokes and memes for Twitter. E don bin tok about smoking weed for Twitter board meeting and anoda times e say e wan buy Coco-Cola to put cocaine inside di drink. Di world most richest man recently buy Twitter for $44 billion and e dey expected to serve as temporary CEO for few months. Oga Musk wey shock pipo wen e make di offer say Twitter get ""tremendous potential"" wey im wan unlock. E don bin dey give insight into wetin di social media platform under im go dey like. ""Twitter go always be free for casual users, but maybe slight cost for commercial/gonment users"", e tok. Elon Musk na 51 year old businessman. Dem born am for June 28, 1971 for Pretoria, South Africa). Im dey known as South African-born American entrepreneur wey follow establish di electronic-payment firm PayPal and formed SpaceX, wey dey make launch vehicles and spacecraft. Im na also di chief executive officer of di electric car manufacturer Tesla. Forbes for dia latest report list am as di richest man in di world. According to forbes Elon Musk worth $219 billion ahead of Amzon founder Jeff Bezos wey carry second wit worth of $171 Elon Musk na 50-year-old businessman. Dem born am for June 28, 1971 for Pretoria, South Africa. Im dey known as South African-born American entrepreneur. Musk establish di electronic-payment company PayPal. Na him form SpaceX, wey dey make launch vehicles and spacecraft. Im na also di chief executive officer of di electric car manufacturer Tesla. Forbes for dia latest report list Elon Musk as di richest man in di world. Musk describe im childhood as difficult, coloured by im parents' divorce, bullying at school. And e tok about im own difficulty reading social cues due to Asperger's Syndrome. Forbes and Bloomberg now rank Elon Musk as di world richest pesin, with a net worth of about $250bn. Im dey tens of millions more than im nearest rival, Amazon founder Jeff Bezos. Elon Musk net worth dey based largely on di value of im shares inside Tesla, of which e own about 17%. E also champions digital currencies and get a hand in several oda smaller companies. Dis include tunnel-maker di Boring Company and experimental brain-computer start-up Neuralink." https://www.bbc.com/pidgin/world-61383204 +business Elon Musk buys Twitter: 'Buy Nigeria' twitter user beg World Richest Man Elon Musk "Elon Musk tweet wia e tease to buy Coca-Cola receive reply to buy Nigeria wey cause buzz. ""Abeg, try buy Nigeria and give us 24 hrs electricity. Nwoke oma bikonu."" Na so di twitter user wit ID @AfamDeluxo reply Elon Musk. Di reply from Aji Bussu handle [@AfamDeluxo] later set Twitter on fire with many users supporting di request. Bussu tweet don get ova 6000 likes and counting. Elon Musk recent tweets dey go viral afta di Tesla CEO strike one deal to buy Twitter. Dat deal to buy Twitter from di founder, Jack Dorsey dey worth about $44bn. For im bid to buy Twitter, Musk promise to reduce censorship on di social media micro blogging site. Musk Coca-Cola tweet don attract ova 528,000 retweets, 140,000 quote tweets, 3.4million likes and counting. Since afta dat reply to Musk Coca-Cola tweet, ""Buy Nigeria"" don get more than 10,000 mentions on Twitter. But in reality, dat twitter user, Aji Bussu, request no fit dey possible or come through because of many reasons. Nigeria no be commodity, na kontri inside west Africa and e no dey up for sale. However Nigerians dey in dire need of any 'messiah' wey fit solve di growing social concerns for di kontri. Nigeria cover area of 923,769 square kilometres and get estimated population over over 200 million pipo. Some Nigerians believe say di company new leadership under South African-born Musk, no go stand wit dem in dia time of need. Twitter get an estimated three million Nigerian users, na important space wia kontri pipo dey take hold goment accountable. And Nigerians dey use am mobilise for political and social causes. Na di social media platform help push #BringBackOurGirls, one rescue campaign for more than 200 schoolgirls Boko Haram bin Kidnap for April 2014. Twitter also push hash tag #EndSARS, wey be movement against police brutality and extrajudicial killings for di kontri in October 2020. Last year, Twitter, under im past CEO and founder, Jack Dorsey, bin come under fire from di Nigerian goment. For early June 2021 di Federal Goment bin ban di platform from operating for di kontri for seven months. Twitter wahala wit di goment start afta dem bin delete one tweet from President Muhhamdu Buhari. At di time, dem tag am ""genocidal"" and say e dey against di platform policies. Elon Musk na 50-year-old businessman. Dem born am for June 28, 1971 for Pretoria, South Africa. Im dey known as South African-born American entrepreneur. Musk establish di electronic-payment company PayPal. Na him form SpaceX, wey dey make launch vehicles and spacecraft. Im na also di chief executive officer of di electric car manufacturer Tesla. Forbes for dia latest report list Elon Musk as di richest man in di world. Musk describe im childhood as difficult, coloured by im parents' divorce, bullying at school. And e tok about im own difficulty reading social cues due to Asperger's Syndrome. Forbes and Bloomberg now rank Elon Musk as di world richest pesin, with a net worth of about $250bn. Im dey tens of millions more than im nearest rival, Amazon founder Jeff Bezos. Elon Musk net worth dey based largely on di value of im shares inside Tesla, of which e own about 17%. E also champions digital currencies and get a hand in several oda smaller companies. Dis include tunnel-maker di Boring Company and experimental brain-computer start-up Neuralink." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61249662 +business Ghana debt stock hit 208.6 billion cedis – Bank of Ghana Bank of Ghana data wey dem release dey show say as of ending of September, de debt stock hit Ghc208.6 billion. Data released by the Bank of Ghana shows that between July and September 2019, Ghana's total debt stock increased by 3.1 billion cedis, hitting 208.6 billion cedis. From de figures wey BoG release inside dema Summary of Economic and Financial Data de total debt stock of 208.6 billion cedis dey represent 60.3 percent of Gross Domestic Product (GDP). Around November last year, de total debt stock for Ghana dey stand at Ghc170 billion, which be like 57.2 percent of GDP. De increase in debt stock over in de last two years according to analysts be sake of how de Ghana cedi dey lose value for de market top plus de recent monies wey govment dey spend to clean up de banking sector. Based on de debt wey Ghana dey owe, if dem divide Ghc208.6 billion by de population of about 30million people, e dey mean say each Ghanaian dey owe Ghc6,950. Some analysts believe say Ghanaians go pay for dis debt in de form of taxes. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50548803 +entertainment BBNaija Pere and White Money fight: Nigerian celebs react to di quanta between di two 'Shine Ya Eye' housemates "Some celebrities for Nigeria don begin react to di clash wey happun between Pere and Whitemoney for di Big Brother Naija 'Shine Ya Eye' reality TV show. For early hours of Tuesday morning Pere and Whitemoney bin get quanta wen di housemates begin di Whisper game, wey Cross introduce for dem to play. Pere later come go confront Whitemoney and demand to know wetin e tell Angel during di game. According to di rules of di game wey Cross bring, one pesin go secretly tell anoda pesin something about anoda housemate. Den di pesin wen dem tell di secret go waka go meet di housemate wey e think say di secret dey refer to but wen Cross call Pere to play di game, e tok say e must hear wetin di last player whisper and dis dey against di rules. Sake of Pere reaction, di housemates end di game but minutes later Pere demand say e wan know wetin Angel hear. Some of di housemates plus Whitemoney para for di way Pere react and dis don make fans plus some celebs to tok. Media personality and former Big brother Africa housemates, Uti Nwahukwu post for im instagram handle say bullying dey ""totally uunacceptable"". Although Uti and Pere don be friends before now and e don dey support Pere since di reality show begin, Uti say im no be di kain pesin wey go hide di truth. ""I love my friends & dey know I no be one pesin wey dey sugar coat di truth. ""Bullying dey totally unacceptable. E no mata who you be or wia you don go, each human being deserve to dey treated wit respect regardless of your opinion about dem."" Uti add say at dis point three things na im dey e mind, either pere dey pay script as wildcards to create drama or e dey play ruthless game to worry im opponent till dey comot or di tension inside di house don enta am. Nollywood actress, Anita Joseph also react and share video of di scene where di clash for happun inside her instagram handle and say she dey pray for Whitemoney to scale through any temptation from Pere. Anita Joseph ask weda di Big brother Naija house na 'Pere camp' or weda im feel say e dey tok to one of e boy. Anoda formern Big Brother Niaja Housemates, Omashola also share di video of clash and ask for im social media platform; 'Wait o, dis really happen.'" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58248544 +entertainment Harrysong: 'Na falling hand if you go tok say you dey depressed' Nigerian musician Harrysong make pipo fear wen tori bin come out say e dey battle with depression. For dis interview with BBC Pidgin, im open mouth yan wetin true-true happun dat time and how e take overcome. Producers: Harry Itie, Sarah Tiamiyu https://www.bbc.com/pidgin/tori-48145387 +entertainment Rachel Bakam: Audu Maikori lead tribute for Actress and TV personality wey die age 38 "Di President and co-founder of Chocolate city entertainment Audu Maikori don pay tribute to Actress Rachel Bakam wey die at di age of 38. For message wey Audu post e say ""Rachel na very inspiring woman, sister and mother wey always get smile, always positive and very clear about her goals."" Tori be say Bakum die for one private hospital for Abuja after brief illness. Audu continue say dis death hit am hard. For di ending part of di im tribute e say ""we lose a true gem, di space she occupy, not many fit fill today."" Dem born Rachel Bakam for Kaduna State where she attend her primary, secondary, and tertiary education. She study English and theatre arts for Ahmadu Bello University and digital filmmaking for New York Film Academy. Until her death, na she be di CEO and Managing Director of Rayzeds Media Ltd, Founder & President of di Nigerian Water Ski And Wakeboard Federation (NWWF) and media consultant for the Performing Musician Employers Association (PMAN) & African Fashion Reception Paris." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56756300 +entertainment Will Smith: Best Actor winner tell Chris Rock sorry say e slap am for di Oscars afta joke about Jada Pinkett hair "Will Smith don tok sorry to Chris Rock say im slap am for di Oscars say im behaviour dey ""unacceptable and inexcusable"". For statement, e say, ""I go like publicly tell you sorry to you, Chris. I bin dey out of line, and I dey wrong"". Dis dey come afta di Oscars film academy bin call Will Smith out over di mata and announce say dem go do formal review. Some film critics tok say e possible say di Academy fit even collect di Oscar from Smith. Di actor bin slap Chris Rock sake of joke wey di comedian make about im wife, Jada Pinkett Smith. Rock bin take Pinkett Smith shaved head do joke. Di actress don share say she get alopecia, wey be medical condition wey don make her hair fall out. Wen Rock bin first make di joke, Smith bin first laff before camera show say Jada Pinkett roll her eyes like say she no like di joke at all. Later, Will Smith comot to collect di first Oscar of im career for im role in di feem, King Richard. Smith tok for di statement say, ""violence for all forms dey poisonous and destructive."" As to why im do am, e say, ""Jokes about me na part of di job, but to joke about Jada medical condition bin dey too much for me and na im make me act emotionally"". E also apologise give di Williams family and di Academy say, ""I deeply regret wetin I do wey don stain wetin don be ogbonge journey for all of us"". Before Smith apology statement, di joinbodi behind di Oscars say dem ""condemn di actions"" of Smith. For 2016, Pinkett Smith bin tok say she go boycott di Oscaes sake of say at dat time she and oda actors of colour bin tok say di awards dey ""too white"". Di #OscarsTooWhite mata bin shele sake of dem bin hardly see any beta nominations for African American, Asian and Latina professionals for di movie industry. Dat same year, Chris Rock bin host di awards and im do joke say wetin dey dia if Pinkett Smith no show. Say e no go affect anytin." https://www.bbc.com/pidgin/world-60868201 +entertainment Big Brother Naija: Wetin we learn about Nengi, Kiddwaya, Ozo and di lockdown housemates from dia 'Truth and Dare game' "18 out of di 20 housemates inside di Big Brother Naija lockdown house dey up for possible eviction dis week afta Biggie introduce new twist for di game dis season. Na only di Head of house Lucy and her deputy Prince wey get immunity for di house. But di housemates no allow di whole nomination walaha spoil dia mind at all. In fact dem decide to ginger demself with di game of ""Truth and Dare"". As with di tradition for di house Neo take charge of di game with di title of oracle and set rules on how dem go run di game. See wetin we learn from di housemates 'Truth and Dare' game on Day 8 for di reality television show. Wen im fellow housemates dare Kiddwaya to kiss someone for 30 seconds. Di 27 year old from Benue state no waste time to to let pipo know wia im heart dey. Im waka straight go meet Erica and di two of dem share dia first kiss for di reality television show. Wen Nengi dare Ozo to pick any girl for di house to give lap dance for 30 seconds, Ozo response no too surprise plenty pipo. E say na only one girl wey im fit give lap dance for di house and dat girl na Nengi. Him do im dare as housemates cheer am on. No be every Housemate wey dia luck shine to kiss somebody wey dem like but dem do oda interesting dares too. Ka3na lick Neo nipples. Brighto own dare for di night na to lick Tolanibaj ear. Anoda housemate wey also do im own dare na Trikytee, im touch Tolanibaj breast. Meanwhile dem neva evict any housemates yet for di reality show wey start on Sunday 19 July. Di show host Ebuka Obi-Uchendu announce during di show say dis season nominations go different. E say Big Brother don introduce new eviction twist. Di new twist wey Biggie introduce na to put all housemates up for possible eviction. Na only di Head of House and Deputy Head of House wey go get immunity. Even though Biggie don set all dis rules for di house, some housemates don begin dey chewing gum demself inside di house. Relationship, situationship and entanglement na wetin fans dey take describe some of di hook ups wey dey happun inside di Big Brother Naija season 5 lockdown house. See some of di 'relationships' wey fans dey tok about for di reality television show. One of di most talked about relationship inside di house na di one between Ozo, Nengi and Dorothy On Sunday during di Live eviction show, Ebuka ask Ozo about im relationship with di ladies, im say Dorothy na im friend inside di house e add say im dey attracted to Nengi. Meanwhile Dora bin don already tell Ozo earlier in di week say ""I no like dis situation and I go remove myself from am,"" na wetin she tell Ozo. ""Even though I know say I want to dey involved with a lady when I enta di game, I no expect us to dey dis close dis fast,"" na wetin Eric tell Neo. Eric and Lilo begin dey close to each few days afta dem enta di house. Di two of dem dey always spend time togeda for di house. On Saturday dem share dia first kiss togeda for inside di reality show. Di oda relationship wey surprise fans well-well na between Neo di Warri boy and Vee di London girl. Neo tell Eric about im own situationship palava, for inside di house but e make am clear say dis love mata wey im dey about to enta no go distract am from di Big Brother game. E say, ""Your own no quick pass my own."" Na wetin Neo tell Eric. ""She don already set her mark, she ask me to be her bestie and give her a massage."" Na wetin im add put. Meanwhile di oda relationship wey fans dey look with side eye for di house na di Kiddwaya, Erica and Wathoni circle. Kiddwaya and Erica don begin gum each oda. On Friday wen Erica bin dey cry inside room Kiddwaya go console her. But e be like say Wathoni like di 27 year old from Benue, afta dia Saturday night party during dia truth and dare game im kiss Wathoni. Wit weeks of plenti drama, romance, Friday night games and di popular Saturday parties, di Big Brother Naija reality TV don produce ogbonge celebrities since e start di first edition for 2006. Dis season 20 housemates dey compete for di grand prize of N85 million naira." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53552688 +entertainment Iyabo Ojo: Nollywood actress tok about work, experience with surgery and her journey as single mother Nollywood actress Iyabo Ojo tok to BBC Pidgin about her work, single mother journey and experience with surgery. Ojo wey dey popular for di entertainment industry say no be crime to be single mother and say surgery she do for her body na for her own self-confidence. Video: Ronke Alo, Sarah Tiamiyu https://www.bbc.com/pidgin/tori-54474150 +entertainment John Boyega don win GQ Icon Award for di second time "British actor, Jon Boyega wey get Nigerian roots don win di 2020 GQ Men of di Year Awards. Di 28 years old ogbonge actor win di GQ Icon Award for di 23rd edition of di GQ Awards wey dey celebrate pipo wey make serious impact for di world inside di last 12 months. Boyega bin dey very active for di Black Lives Matter worldwide protest wey happun for di middle of di year, and according to GQ, im ""speech for June fit be di koko wey make dem name am GQ Icon."" Di actor bin also dey among di pipo wey bin cari di ENDSARS protest for head. Dis go be di second time wey im dey win di Icon award. Di first one for 2016." https://www.bbc.com/pidgin/55104675 +entertainment Oscar nomination 2022: Full list of nominations don comot "Di nomination list for di 2022 Academy Awards don comot. Di awards wey go hold on Sunday 27 of March go get host for di first time since 2017. Howeva we neva know how go be di host. Part of di nominees include Will Smith wey dey nominated for Actor for Leading role with Denzel Washington. Will Smith gbab im nomination for di feem, King Richard. Di movie wey Will Smith follow produce also gain five oda nominations for Best picture, actress for supporting role, film editing, writing for original screenplay and Original Song. Dis na di first time di actor dey get Oscar nominations since 2007 when e gbab nominations for The Pursuit of Happyness. Most nominations go to The Power of the Dog wey Benedict Cumberbatch act with 12 nomination as well as Dune wey Zendaya and Timoth Chalamet follow act for wey gbab 10. Denzel Washington dey nominated for Actor for a Leading role for im role inside di movie, The Tragedy of Macbeth. Popular cartoon, Encanto also get plenti nomination for Animated Feature film and Original Song for Dos Oruguitas. Dis na as pipo don dey ask why di hit song from di cartoon, ""We don't talk about Bruno"" no get Oscar nod, di answer na say Disney no even submit am for consideration. Coming 2 America wey be di part 2 of Eddy Murphy 1988 hit feem get nomination for makeup and hairstyling." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60280749 +entertainment Nedu Wazobia: Comedian Nedu reveal DNA result of son afta ex-wife accuse am of domestic violence E be like say couple gbasgbos be di hotcake ontop Nigeria social media space dis weekend as anoda celeb couple don bring dia mata enta Instagram just few days afta di Idibia family mata. Dis time, na popular comedian and broadcaster Ani Chinedu Emmanuel wey plenti pipo sabi as Nedu marriage to im ex wife Uzoamaka Ohiri mata dey trend ontop social media. Tori be say, di ex wife Uzoamaka on Friday night for her Instagram story bin drag di broadcaster and accuse am of domestic violence, but Nedu don deny her claims. Uzoamaka inside series of posts accuse say Nedu bin beat am weeks afta she born dia son thru operation. 'I don ready now, make we take care of di girls, leave my son out of dis... Una rememba dis picture? You beat beat me up while your mama carry my new pikin afta 2 weeks of operation' she tok. Nedu for im own response to di allegation of abuse for one long Instagram post tok say Uzoamaka dey lie and if anybody won tok of abuse na im (Nedu) suppose tok am. E further claim say police dem don already investigate di mata wen dem bin try end dia marriage. ''On di allegations of domestic violence, dem don investigate dis mata twice, one for police station wey dey Ajah and anoda by competent court of law during di dissolution of our marriage'' ''Both times, dem clear me of all allegations and I gat receipts to back am up.'' e tok. Di broadcaster no come end dia, e further tok say e bin carry dia 3 pikins go do paternity tests and result show say dia first son no be im biological pikin, di allegation wey di ex-wife later confirm for her post. ''Our marriage bin dey plagued wit a lot of issues. One of which be continuous infidelity from her side wey make me go do paternity test for our pikins and wey im test reveal say our first son no be my biological pikin, even though we born am wen we bin dey married.'' Uzoamaka post her response to di DNA certificate wey Nedu share for her Instagram page and say e no longer dey secret. Nedu and Uzoamaka marry for 2013 and born 3 pikins, 2 girls and one son. E no dey clear di year wey dem divorce. Who be Nedu Ani Chinedu Emmanuel alias Nedu na popular On-Air-Personality, broadcast journalist, comedian and skit maker. Dem born am for Kaduna state and study accountancy for Madonna University, Anambra state. E dey popular for im different characters wey include Alhaji Musa, Sister Nkechi , EndTime Landlord and Officer Jato. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58449266 +entertainment Peter Okoye: Mr P don respond to fans wey want P-Square' twins to reunite "Nigerian musician Peter Okoye don answer fans wey want P-Square' twins to end dia beef and reunite again. For post wey di musician caption speaking my mind for im Instagram page, e say: ""Go back! Go back!! Go back!!! and do wetin exactly? Afta una say I know sabi sing?"". E continue to tok say: ""Again going back no be for me to make more money? I write official resignation letter 4 yrs ago say I no longer dey part of di group! Na by force""? Dis dey come weeks afta im twin brother Paul Okoye post about how pipo claim say im yab Peter wife Lola Omotayo-Okoye afta she wish am happy birthday and ask dem to end dia beef and reunite. Na 2003 di top Nigerian musicians wey be identical twins, Peter and Paul Okoye start dia music career wit different bangers and plenti awards. But for September 2017, reports bin drop say di duo don go dia separate ways sake of family kwanta. Di musician also address di mata of im family for inside di post. ""Blood thick pass water! Blood thick pass water! Abeg my wife and children dem be water or Zobo"". Na wetin e tok. E tell fans wey dey hala say dem only know PSquare and not Mr P to go PSquare page to go complain, im no dey part of di group. Peter add say make fans enjoy im new single ""Follow My Lead"" in peace! wey im go release Friday 11 December." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55262263 +entertainment Stanley Okoro death: Nollywood actor Stanley Rabbi Okoro wey die at 29 - Profile "Nollywood actor Stanley Rabbi Okoro death at di age of 29 shock Nigeria entertainment industry. Stanley Okoro na one of Nollywood fast growing prominent talents wey many sabi as Junior Ibu or Stanley Rabbi O. Okoro die on Wednesday August 11, afta im get wetin dem suspect be a case of food poison. one day before im die, di young man bin post for im Instagram say ""If money when you get no fit solve your problem, my brother chop."" Stanley na one of Nigeria fast-rising actors and one of di funniest for Nollywood. Okoro na di CEO of 27ELEVEN entertainment and apart from being actor, im na MC, promoter, content creator, brand influencer, and digital marketer Feems wey im act include comedies like ""The Briefcase"", ""Marriage War"", ""Royal Tigress"" and ""Behind di Mask."" Oda movies wey im bin shoot before im die include ""Order of di dragon"", ""Abada na South"" and ""Pocket Book."" Dem born Stanley Okoro on di October 10, 1992. Im die at di age of 29 year on 11 August 2021. Although im bin live for Owerri di capital of Imo State, Okoro na from Enugu State. Stanley na graduate from Benue State University." https://www.bbc.com/pidgin/58193185 +entertainment BBNaija: How fans vote Lucy comot Big Brother Naija lockdown season 5 house Lucy na di latest housemate to leave di Big Brother Naija reality television show. Out of di six housemates wey dey up for possible eviction dis week na she get di lowest votes from di fans She be di 11th housemates to chop eviction afta Lilo, Ka3na, Eric, Tochi, Kaisha, Prince, Wathoni, Tolanibaj and Bight O. As e be so, nine housemates still remain for di house out of di 20 wey start di show for July 19. See how di fans vote for di six housemates wey bin dey up for eviction. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54049202 +entertainment Burna Boy: 'I deserved to win Grammy' "Nigeria ogbonge musician and Grammy award winner Burna Boy tok to BBC about how im make di album Twice as Tall inside lockdown. Di singer wey win di Best Global Music Album category for di 63rd Grammy Awards afta dem nominate am two time back to back, na one of di most successful African singer for world. Burna wey describe in sef as ""di stone wey di builder refuse"" say producing im Twice as Tall music video inside lockdown bin dey ""very fun and convenient at di same time"" as dat na di first time wey im eva sidon for im house do everytin from home. Im go on to tok about why e dey important for Africans to tell dia own story becos stories of di continent dey dey twisted wen odas tell am. But according to am, ""now na di time to turn all dat becos finally we get generation of Africans wey no go gree to dat"" and now na time to change di narrative back to di truth. Di Grammy award winner believe say im for don win this award since if to say im kontri get leaders wey dey support young pipo. ""If to say we get leaders wey dey take di youths serious and some kain infrastructures dey ground den I for no win di Grammy for 2021, I for don win di Grammys for 2013 or 14""." https://www.bbc.com/pidgin/media-56473931 +entertainment Enisa to Eniola: Why Nigerians for Twitter turn dis upcoming American singer to 'Naija babe' Nigerians dey gbadun one American singer Enisa music and pipo dey show her love for di West African kontri ontop social media.Tori be say na afta di 23-year-old singer wey dey live for Brooklyn, bin join Nigerians to 'sorosoke' during di End SARS protest as she post tweets to show solidarity and awareness. Dis one totori Nigerian youths no be small wey come decide to return di favour, na so dem begin stream her song, 'Love Cycle'. Di wey di singer bin carry di End SARS mata for head, dey chook mouth for di tok-tok for Twitter, make some pipo dey wonder weda she be Nigerian. Na so Nigerians come decide to even dash her Nigerian name wit Yoruba origin, Eniola wey mean 'Pesin of wealth'. Dem even begin photoshop her inside different native Nigerian attire. E no end dia, even ogbonge singer Davido don agree to do collabo wit her for di remix of her song. As e be so, Enisa Twitter account don rise from few thousands to over 49,000 followers in less dan two days, as more and more Nigerians dey claim her as one of dia own. Enisa na 23-year-old pop singer from Brooklyn, New York, America. Di young singer dey make blend of pop and soul music. https://www.bbc.com/pidgin/55205391 +entertainment Grammy nominations 2022: Wizkid, Rocky Dawuni, Femi Kuti, Angelique Kidjo Best Global Music Album category and how di recording academy dey pick di winner "Di Grammy academy announce im nominees for di 64th awards ceremony on Tuesday, 23, November, 2021. Di Recording Academy reveal di nominations for all 86 categories for di 2022 GRAMMYs Awards show. Inside di categories, Nigerian musician Wizkid and Femi Kuti get nomination for di Best Global Music Album among oda musicians like musician, Rocky Dawuni, Angelique Kidjo, and Daniel Ho & Friends. Before di 2020 Grammys, 'Best Global Music Album' dey known as di 'Best World Music Album' category. Grammy say dem change di name to make am more relevant, modern and inclusive. ""Di change dey symbolise a move away from di idea of colonialism, folk and 'non-American' wey di former term dey carry as we dey try adapt to current listening trends"", dem add. Na only Recording Academy voting members dey determine who dem go nominate or who go be winner of any Grammy Award category. Dis members na music creators, plus artists, producers, songwriters, and engineers wey di Academy don already choose sake of dia expertise. Afta dem don determine who dey nomination list and announce am, di members of di Academy go begin vote to determine winner for each of di category. Academy members dey vote for up to ten categories across up to three fields for di genre fields Dem go also vote for four categories of di General Field to determine di winners. To ensure di quality of voting, members go only directly vote only for dia fields of expertise. Na di number of votes from members of di academy go determine who go be winner for dis year Best Global Music Album awards out of Femi Kuti, Wizkid, Angelique Kidjo, Rocky Dawuni and Daniel Ho & Friends. Meanwhile Beninese musician, Angelique Kidjo don win dis category three times. Who be di oda musicians wey don win am in di past ten years? 2020: Burna Boy win wit im 'Twice As Tall'' 2019: Angelique Kidjo win wit 'Celia' 2018: Soweto Gospel Choir win wit 'Freedom' 2017: Ladysmith Black Mambazo win wit 'Shaka Zulu Revisited: 30th Anniversary Celebration' 2016: Yo-Yo Ma & The Silk Road Ensemble win wit 'Sing Me Home' 2015: Angelique Kidjo win wit 'Sings' 2014: Angelique Kidjo win wit 'Eve' 2013: Dis year, di category get two winners Gipsy Kings wit Savor Flamenco plus Ladysmith Black Mambazo wit dia live performance of 'Singing For Peace Around The World.' 2012; Ravi Shankar win am wit 'The Living Room Sessions Part 1' 2011: Tinariwen wit 'Tassili' WIZKID Wizkid wey e real name na Ayodeji Ibrahim Balogun, na Nigerian singer and songwriter. E also dey known as Wizzy or Starboy and na one of Africa biggest artistes. Wizkid begin dey recordi music for very young age and manage to release one collaborative album with di Glorious Five, one group wey im and some couple of e church friends form. E rise to dey popular afta e release ""Holla at Your Boy"", di lead single from im debut studio album Superstar for (2011). ""Tease Me/Bad Guys"", ""Don't Dull"", ""Love My Baby"", ""Pakurumo"" and ""Oluwa Lo Ni"" na also part of wetin im release as singles from di Superstar album. For 2016, Wizkid achieve international recognition afta e collaboration with Drake for di global hit, ""One Dance"". For 2019, e feature for Beyoncé project Di Lion King: di Gift for di collaboration ""Brown Skin Girl"", wey make am win Grammy Award for Best Music Video. Femi Kuti Femi Kuti, na son of di late, legendary musician Fela Kuti. Before Femi become im own band leader, e start to dey play saxophone for e father band, Egypt 80, for 1979 where e learn everi-everi about performing with a legend. For 1986, Femi create im own band wey dem call Positive Force, and e quickly dey popular as strong group for Afrobeat music. Femi don perform for some of di world most ogbonge stages and festivals, and collaborate with big musicians for different genres. E get two nominations for di 2022 Grammy; im song Pà Pá Pà dey for di list of Best Global Music Performance while e Album Legacy + dey Best Global Music Album list. Anglique Kidjo Four-time Grammy Award winner Angélique Kidjo na one of di greatest artists for international music today, She get thirteen albums to her name. Di Benin Republic musician fit sing for more dan five languages. Time Magazine don call am ""Africa's premier diva"". Di BBC don include her for dia list of di continent 50 most iconic figures, and for 2011, The Guardian list her as one of dia Top 100 Most Inspiring Women for di World. Forbes Magazine don also rank Angelique as di first woman for dia list of di Most Powerful Celebrities for Africa. As a performer, her ogbonge voice, stage presence and ability to speak plenti languages don win am respect from her peers and expand her following across national borders. Rocky Dawuni Rocky Dawuni don first collect Grammy nomination for di year 2015 for di Best Raggae Album category wit im Album 'Branches Of The Same Tree' Rocky Dawuni na Ghanaian singer, songwriter and record producer wey dey perform im signature 'Afro Roots' sound wey get mixture of Reggae, Afrobeat, Highlife and Soul music. Dawuni don share di stage wit Stevie Wonder, Peter Gabriel, Bono, Jason Mraz, Janelle Monáe and John Legend, among many others. CNN bin don name am as one of Africa Top 10 global stars. Im stature as a cultural diplomat and successful melding of music and activism don lead am to become tok-tok pesin for different global causes. Im be United Nations Goodwill Ambassador for Africa for UN Environment." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59398519 +entertainment Davido new album: When 'A Better Time' album dey drop? Davido don reveal di tracklist for im third studio album - A Better Time, less than a year afta im release A Good Time. For social media post, di Nigerian star, bin reveal di tracklist of di album togeda wit di different artists wey im feature. E announce say im go release di album for Friday, di 13th of November, 2020. Di 17 track album bin feature foreign artistes dem like Nicki Minaj, Chris Brown, Young Thug, Nas, Lil Baby, and Hitboy, e also include African stars like Sauti Sol, Mugeez and Sho Madjozi. Nigerians stars like, Tiwa Savage, Mayorkun, C Kay and Bella Shmurda also feature for dis new release wey go be di musician third studio album. Many pipo don dey yarn about di album before e drop as Davido bin don release two singles from di album wey include Fem and So Crazy wey feature Lil Baby. Some pipo yab di soon to be released album, sotay Lil Baby tok say im no go dey feature for songs again. While some fans dey hail di album say e go be anoda banger for di Nigerian music industry, odas dey hate one of di singles of di album say e be trash. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54875519 +entertainment Helen McCrory Harry Potter: Damien Lewis announce death of e wife but who she be? "Actress Helen McCrory, wey dey popular for her roles in Peaky Blinders and three Harry Potter films, don die of cancer for di age of 52, her husband, Damian Lewis, announce. Her husband wey also be actor tok say im dey ""heartbroken"", and add say e late wife na ""beautiful and mighty woman"". ""She blaze so brightly. Go now, Little One, into di air, and thank you."" Dey born Helen Elizabeth McCrory wey be award-winning actress on di 17 August 1968 for London. McCrory spend one year for Italy before she study acting for di Drama Centre. She begin her career on stage for UK before acting for oda films. During her theatre, television and film career, McCrory pick up plenty awards, like best actress for di London Film Critics Circle, di Broadcasting Press Guild Awards, di Critics' Circle Theatre Awards and theatre actress of di year for di Glamour Awards Helen McCrory marry Homeland star Lewis for 2007 and dem born two children, Manon and Gulliver. Last year, Helen and her husband raise more than £1m to provide NHS workers with meals from high street restaurants during di pressures of di coronavirus pandemic. Helen McCrory play di commanding matriarch, Polly Gray, for di TV series Peaky Blinders. But she spend much of her career for theatre. She meet her husband, Damian Lewis for 2003 play wey dem title Five Gold Rings for London Almeida Theatre. Helen McCrory continue to take to di stage even as di period drama about di Shelby clan later become one ogbonge hit - she play di leading role for di National Theatre production of Medea for 2014. McCrory act as Narcissa Malfoy, di wife of Lucius Malfoy and Draco mother for di final three Harry Potter films; dat na Harry Porter and the Half-Blood Prince and Harry Potter and the Deathly Hallows: Part 1 and Part 2. As di film franchise dey about to end for 2011, Helen McCrory put her eyes for oda international hits - she play Mama Jeanne for Hugo, wey receive 11 Oscar nominations for 2012. During dat year she also play di MP Clair Dowar for James Bond instalment Skyfall. No be di first time Helen McCrory dey play ogbonge figure for di British political world, she don first appear on screen as former Prime Minister Tony Blair wife Cherie twice - for di 2010 film The Special Relationship and in the 2006 release The Queen. National Theatre artistic director for UK, Rufus Norris say McCrory ""without question be one of di great actors of her generation""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56783545 +entertainment Omah Lay, Tems arrest in Uganda: Burna Boy, Laycon, Teni, Peter Okoye and odas react to Nigerian singer palava "Nigerian artistes and entertainers don begin raise voice in support of dia colleague Omah Lay, wey authorities hand cuff and remand for prison ontop accuse say e break dia Covid-19 rules. Laycon, recent winner of di Big Brother Naija TV show, award winning musicians Teni, Sound Sultan, follow ask questions after Uganda Police charge Omah Lay, and two oda Nigerians wey go di East African kontri to perform for one concert. Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openyi alias Tems and Muyiwa Awoniyi appear for Magistrate court on Monday 14 December ontop charge of ""negligently doing acts wey fit spread infectious diseases"". ""Why dem no shut down di [show] before e happun?,"" Laycon bin ask even as anoda Nigerian celebrity Sound Sultan para say na di promoters of di show Uganda authorities suppose dey face accuse. Burna Boy, di two-time Grammy nominee sef chook mouth for di mata. Omah Lay on Monday afternoon, post for Twitter wia e ask why Uganda goment dey use im mata take play politics. Already, some pipo don dey call for Nigerian artistes to boycott di MTV Africa Music Awards (MAMA) wey suppose hold for Uganda capital Kampala in few months time. Di singer blow for 2020 afta e release back to back hit songs, one of which na ""Ye ye ye"" and make Apple Music name im ""Godly"" song one of di most played for Nigeria." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55265377 +entertainment "DaBaby Jojo Siwa: American rapper Jonathan L. Kirk ""Beatbox freestyle"" call Nickoledeon Star Jojo Siwa N-word" "Jojo Siwa na 17 year old Nickoledeon Star with multi-million dollar hairbow business and Jonathan Lyndale Kirk AKA DaBaby na very popular rapper, so wetin connect di two? Na wetin plenti pipo start to dey ask dem self afta di rapper release ""Beatbox freestyle"" on Friday. And mostly because e just comot from no where, unprovoked. Dababy say ""N-word, you a bitch, Jojo Sinwa, bitch"". even hold her picture for di video. Twitter para no be small on top di mata with some pipo yabbing dia height difference, while odas decide to enta how she get money pass am. But DaBaby comot to explain di mata afta di whole of Twitter para. For tweet im say, im add di Youtuber name inside im freestyle because im three year old pikin sotay im don spend im money buy every product Jojo bring come outside. Im come add say no be beef, na just word play wey di internet no quick understand. E further add some bars, wey e use her name tok for Twitter say ""I don't Siwa they so mad."" Meanwhile since di gbege start, di former ""Dance Mom"" star neva comot to say anything. Dis na as di 17 year old don dey get several bashing from different sources since she comot as part of di LGBTQ for January. [Jojo Siwa net worth] - While we neva know plenti tins on top di money wey she dey make on top say you go need to comot how much she dey pay suppliers, taxes and oda costs wey dey come ith her business, Jojo Siwa bin reveal say for 2018 alone she sell pass 40 million bows world wide wey fit make average of 400 million dollars. And she get oda tins wey she dey sell. Dis one no add di money she dey make from her movie, music and YouTube career wey boast of more than 12 million subscribers. As well as the TV cartoon wey she dey do with Nickelodeon. And money wey comot from concerts wey she do for 2020 alone. Many Sources tok say her net worth fit dey around 14 million dollars. [DaBaby net worth] - On di oda hand, many sources put DaBaby at three million dollars with im source of income as rapping, song writing, performance and streaming money. Im bin reveal for one sonfg, ""More Mone, More Problems"", say im get $300,000 to perform for show during Covid-19. Tori be say , before di pandemic hit, im bin dey make $124,000 per month but nobodi really know im deal with Interscope Records wey im sign with as di details of im contract dey private." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56142451 +entertainment Big Brother Naija housemates Erica and Kidd Waya do 'everitin' for Head of House lounge, Ngozi Nlewedim reveal "Video of how Erica admit say Kidd Waya wit her do blow job and 'everitin' for Head of House Lounge inside Big Brother Naija 2020 lockdown season don show. On Wednesday night na im Erica wey real name na Ngozi Nlewedim reveal dis open secret to fellow housemate Neo. ""If dem show videos of all di tins wey happun for dat head of house lounge, ehhh Jesus, even me I no wan watch, I go dey so embarrassed"" As Erica dey tok, Neo ask her weda she do 'blow job?' and she admit say she do everitin Na while di housemates played anoda round of di spelling bee inside di garden, na im Erica wey dey currently serve as BBNaija Head of House for second time take di opportunity to reveal di mata to Neo. Just di odo day fans dey react afta Erica of Big Brother Naija blast kiddwaya on Friday night about dia relationship inside di house. Many of dem dey wonder if di ""Kiddricca ship"" as dia fans dey call dem don crash sake of wetin Erica tok. Tori be say Kidd Waya and Erica na strong padi padi sotey marriage tok ontop dia mata don dey fly up and down." https://www.bbc.com/pidgin/world-54008749 +entertainment Rachel Oniga: Movies, biography and tributes for Nollywood veteran actress "Tributes don dey enter from di Nigerian entertainment industry after di passing away of ogbonge Nollywood actress Rachel Oniga wey die at age 64. Na on Saturday, family of madam Oniga confam say di actress pass away from heart problems wey begin small time before she depart. Her colleague Patience Ozokwo, wey dem two follow dey di set of entertainers wey ginger di rise of Nigerian feem industry (Nollywood) for di 2000s, pay tribute. ""We bin plan so many tins wey we go do togeda. Her last words to me [na] 'Don't forget me oooh' and I said 'NEVER',"" Ozokwo bin write inside emotional video post for Instagram. Funke Akindele-Bello di star of hit tv show 'Jenifa' post for social message say ""Thank you say you dey good to me. God knows best. Rest In Peace ma!"". Some early reports bin say Oniga die from Covid-19 complications but di family notice wey dem publish on di actress official Instagram deny dis. As one of di ogbonge actress wey follow raise di profile of Nollywood feems from di late 90s, Oniga don act inside more than 100 feems both in her kontri and internationally. Her feem credits include di 2018 hit feem 'Chief Daddy' wey Akindele-Bello and Kate Henshaw-Nuttal follow act inside. Dem born Rachel Tabuno Oniga on 23 May 1957 for Lagos although she bin hail from Delta State, Nigeria. She begin her acting career for 1993, and small time afta feature inside 'Sango' wey bi feem about di Yoruba deity god of lightning. But many Nigerians go sabi am for her role inside long-term television show 'Super Story'. Oda tins to sabi" https://www.bbc.com/pidgin/tori-58041695 +entertainment Triplet models: Tomisin, Tomiwa and Toni dey totori pipo for social media with dia modelling work and life BBC Pidgin follow one set of triplet wey dey model for instagram, Tomisin, Tomiwa, Toni tok on dia modelling work together and how pipo dey react to dat. Oya follow hear from di 20-year-old triplet models dem wey dey burst pipo head ontop social media. Producer: Moseph Ekine Video journalist: Sarah Tiamiyu https://www.bbc.com/pidgin/media-57128761 +entertainment Majek Fashek US burial happun on Friday, Nigeria memorial to follow next year "Fans of di 'Rainmaker', Nigerian music legend Majek Fashek, fit say dia final bye-bye to am, as im burial ceremony don hold for United States. Fashek wey im real name na Majekodunmi Fasheke receive 'quiet ceremony' on 21 August, according to wetin di musician manager Uzoma Omenka, tell di BBC. Omenka thank all fans and explain say di reason why dem bury am for US na di coronavirus pandemic, although e no tok pass dis one. Omenka promise say dem go make sure say ""befitting memorial"" go happun in Nigeria - wia dem born Majek - next year. Di Nigerian reggae performer, wey dey popular for im hit song like Send Down the Rain and So Long for Too Long, die for im sleep for New York at age of 57. He also write di song Free Africa, Free Mandela, wia im call for di release of Nelson Mandela inside apartheid South Africa. As sign of how im blow ontop international scene, for 1992 on di David Letterman chat show on US television, he sing So Long for Too Long from di album Spirit of Love." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53876291 +entertainment Ric Hassani: Waje picture of di Nigerian musician for social media dey make pipo tok - See wetin you need to know about am "Waje post picture on Tuesday wey dey make social media to scratch head on top wetin dey happun. For di picture she snap with musician Ric Hassani and post for social media wia she dey laugh, she write ""It is time"". Pipo start to dey wonder wetin dey happun, wen singer Omawumi and actress Mercy Johnson Okojie start to dey post congratulation message. E never clear wetin di picture mean. Although some pipo reason say na music collabo dem wan do. But wen BBC Pidgin reach out to her team, dem say ""big announcement dey comot soon."" Waje, herself tok say, ""I no wan tok about am now, but I dey very happy."" Ric Hassani no do like say e sabi wetin dey happun. E post for Twitter say, ""More pipo don dey sabi me for street as I dey waka, nna abeg wetin happen? Abi my sextape don come outside? Please wetin de happen this morning?"" Ikechukwu Eric Ahiauzu wey dey popularly known as Ric Hassani no be Johnny just come. For 2017, di music artiste blow wen im comot with di song ""Gentleman"" and follow dat one with Believe, Number One and Marry You. Im don work with artistes like Falz, Olamide, Chike and Johnny Drille. Im dey mostly popular on top say e dey like to release love songs. Later dat year, im comot with im first album wey im call, The African Gentleman. And for 2019, drop im EP, Love & Christmans. Late for 2019, im comot with ""Do Like Say"" wey im release with boyband wey im form called DBYZ." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55707600 +entertainment BBNaija 2020 evicted housemate: Tolanibaj clear di air about her 'feelings' for Neo "One of di latest Big Brother Naija housemates to comot, Tolanibaj say pipo dey misunderstand her feelings for Neo. Tolanibaj bin follow Erica tok for one of dia gist say she bin dey attracted to Neo. For interview wey Brighto, Tolaniaj and Wathoni do wit BBC News Pidgin, Tolanibaj say; ""I bin tok say Neo na fine boy no be say I like am. ""I feel say Nigerians suppose understand di difference between say pesin find pesin attractive and you like di pesin, Wetin I do na to just compliment say wow dis pesin-Neo dey attractive no mean say you wan date di pesin or you suppose date di pesin."" she add. She tok say her compliment about Neo na innocent compliment. See di full interview with Brighto, Tolanibaj and Wathoni here: Fans bin dey disappointed wen Tolanibaj make di comment for di live show and dem feel say she no suppose feel dat way about her friend- Vee boyfriend. She also tok about her relationship wit Prince say dem start am just to catch cruise but she no dey clear yet wetin go happun wen Prince comot from di house. Wen we still ask Tolanibaj who she wan make e win di 2020 edition of Big Brother Naija season, she say she go like make Prince win am." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53988301 +entertainment Kanye West Donda new album go honour e mama "American rapper, Kanye West don release im number 10 studio album and e be tok of town. Di album wey im name Donda, in honour of e late mom, don receive many accolades from fans across. Di controversial rapper bin first announce di news on im official Twitter page along wit di track list before im later delete di post. Kanye bin previously tell fans say im next album go be ‘God’s Country’ but di tweet later suggest e don get new tittle in memory of im beloved mama, Donda. Donda West die for late November 2007 afta cosmetic surgery complications. Di dad-of-four give im fans preview of one of di tracks, called Donda, for im mama birthday on July 12th. Dem born Donda on July 12, 1949, for Oklahoma City, Oklahoma. She marry Ray West, wey be Kanye papa, but after dia divorce, she move wit her son to Chicago in 1980. Di single mother bin get Bachelor’s degree in English from di Virginia Union University, in Richmond Virginia. She receive Master degree for Atlanta University, Georgia. Donda bin later continue her education and she later gbab Doctorate in English for Auburn University, Alabama. On November 10, 2007, Donda West die of coronary artery disease Plus multiple post-operative factors sake of di consequence of liposuction and mammoplasty wey she bin do. She go through liposuction, one tummy tuck, and a breast reduction di day before she die. She be 58 years old at di time wey she die. Records show for 2001, two malpractice lawsuits against Jan Adams, di plastic surgeon wey perform procedures on Donda, ended in judgments of $217,337 and $250,000. Later di governor of California dat time, Arnold Schwarzenegger sign di ""Donda West Law,"" legislation wey make am compulsory for patients to receive medical clearance through physical examination before dem go fit do elective cosmetic surgery. Kanye dey very close to im mama and her death bin touch am greatly. For one interview wit Q magazine in 2015, e tok say: “My mama na everything “If I bin no move come LA, she for still dey alive. I no wan go far into am because e fit make me cry. Before di release of im new album on Friday, July 23, 2021, videos of di rapper wit im ama don dey circulate for social media. In 2020, Kanye release di song Donda, a testament to im late mother, a year before unveiling im 10th album. Di album feature artist like Jay Z, Lil Baby, Lil Durk, Pusha T, Travis Scott and oda artists" https://www.bbc.com/pidgin/world-57947404 +entertainment Bukunmi Oluwasina: Who be dis Nigerian actress wey her love tori totori Nigerians "Nollywood Actress Bukunmi Oluwsina don marry her long time lover Ebun. On Thursday, She enta social media to post di video of her wedding and tok how much she love her man and go chose am over every man forever. Since her wedding video enta social media, fans and colleagues don dey comment. For di video, she wear white wedding dress wit her husband for court and na only two of dem dey di video. She write say ""Love dey patient, forgiveness and no dey give up. No be too just dey give woman money and buy her things but also to make her happy and say she love am"" Apart from dia long years of relationship wey make some of dia fans dey wonder how, wetin she write also dey make dem react. Bukunmi Oluwasina Grace na na award winning Nollywood actress wey dey popular for Yoruba movies. Wetin pipo no sabi about her na say she dey sing, she be scriptwriter, movie producer, director, sound track composer, brand influencer and model. Na she be di brain behind plenty sound track for Yoruba movies. Dem born Bukunmi on di May 7 for di early 1990's inside to di family of seven and na she be di third pikin. She come from Oke-Imesi, Ekiti state, South West Nigeria. Bukunmi na graduate of Obafemi Awolowo University where she get Bachelor Degree for Theatre Arts. Di actress begin write movie scripts when she dey secondary school. She blow afta she produce one Yoruba movie ""Ayomi"" wey she take collect award. Di movie give her popularity as e make her partner wit Pepsi co. and Vivas. She also get NGO wey she dey take help pipo. Bukunmi Oluwashina don write plenty movie scripts wey include A story like Mine, Oluwere, Itan temi, and Beautiful song. She don feature for plenty movies too and work wit ogbonge artiste for di movie industry. Dem nominate her as di Best Indigenous Movie (Yoruba) category for di 2015 Africa Magic Viewer's Choice Awards. She win oda awards like:" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54026590 +entertainment """BBNaija Laycon"", Nengi, Dorathy, Neo, Vee vote one of housemates wey go win Big Brother Season 5 2020 live television series" BBNaija housemates wey remain for dis 2020 live television reality show; Laycon, Dorothy, Nengi, Neo and Vee vote who go win di lockdown series. Fans of di show still get chance to do final voting for who go win di N85 million worth of prizes come Sunday. go close by 10pm Lagos time on Friday 25 September, 2020. Dorathy think say if she no win Big Brother, then Neo go win am. She tell Biggie for Diary room session on Friday afternoon say she believe say im gra-gra alias energetic personality go fit make am di winner. Vee believe say if no be she win Big Brother, e go go to Laycon. She tell Biggie for Diary room session on Friday afternoon say she belive say im brains and vision go seal di deal for am. Laycon think say if im no win Big Brother Naija, Dorathy go take am because of her warm personality and sweet nature. Nengi tell Biggie for Diary room session on Friday afternoon say she think say if Big Brother no be she win am dis time, Laycon go be victorious. Neo thinks say if im no win Big Brother, Nengi win because she dey pretty and down to earth. Victoria Adeyele wey be 23 years old na musician wey base for Lagos, Nigeria. Dem born and raise her for London and she move come Lagos almost one year ago to begin her music career. She say her parents na Nigerians and say she dey enjoy acting, socializing and making pipo laugh. Vee say she no eva don dey relationship wey last longer than six month. Dorathy Bachor na 24-year-old entrepreneur from Delta State and she believe she be di only one wey fit make you smile. She say her biggest achievement na SHOPFORME - dat na di biggest procurement company inside Nigeria. Emuobonuvie Akpofure na 26 year old ride-hailing app driver from Delta State . E describe imsef as fun, tolerant, loving and smart. E also dey secretive. E biggest achievement na wen im win N 500 000 from one talent competition. E say e like wen pipo dey underestimate am and call imsef problem. Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos. E be graduate of philosophy from University of Lagos. E say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata. E biggest achievement na im song 'Fierce' wey dey for MTV BASE Top ten charts for six months. Rebecca Hampson na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures. She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef. https://www.bbc.com/pidgin/world-54300563 +entertainment DJ Cuppy: Femi Otedola daughter Florence Otedola say to be im pikin na to 'learn sometin new everyday' "DJ Cuppy no need too much introduction to many pipo for Nigeria and even across Africa. DJ Cuppy aka Ifeoluwa Florence Otedola na di daughter of Nigerian billionaire Femi Otedola, but she don manage to build a brand for herself away from her papa billions. She describe herself as DJ, artiste, philanthropist and student. She currently dey run her further studies for Oxford University for UK. ""I tink say pipo no understand me, pipo dey tink say I just dey chop life but my work no be beans oh, I dey do so many different tins."" She tok say she dey funny, and she like to enjoy life. ""My own way of thinking be say pesin get one life to live so you get to live am, so many pipo dey tink say becos my papa get money or becos say I grow for abroad, I don forget my roots, but Lagos na wia dem born me...Lagos na my home,"" na so Cuppy tell BBC Pidgin. For BBC exclusive interview, Cuppy also tok about her life, work and aspirations and why she still dey single. Cuppy say some of di tins wey dey motivate her women issues and young pipo. ""Di tin wey dey motivate me di most na young pipo for di kontri. Pipo dey suffer everyday."" I build Cuppy, my name away from Otedola so I fit make opportunities for oda pipo. I wan make say if you be young girl for street see say if you work hard you fit do am yourself. She tok say anoda tin wey dey motivate na woman issues. ""I enta DJ job wia plenti man dey and I decide say I go do am, I go am beta pass dem."" Cuppy add say even dou e be like everyday be jolly-jolly, she dey get both di good and bad times. But her real motivation dey centered around di girl-child. ""Di tin wey dey really ginger me, na even wen I see young girls say dem wan be like Cuppy...e be like I don dey build my own legacy outside of my dad and as a woman, I must always be example."" Cuppy say her experience as DJ no be easy one, but na sometin she bin dey determined to do. ""Even today, I still dey struggle wit different different tins. Pipo dey tok, Cuppy no fit Dj, she no sabi dress, Cuppy only like pink, she no marry, plenti-plenti tins. But for me, e dey important say you dey do wetin you wan do. I believe in God and I come sabi say God give me opportunity so I fit carry my destiny."" I like to push, I like to waka upandan na why my tag-line be Cuppy on a mission."" On weda her papa and heritage give her chance pass to dey successful, she tok say: ""Wen pipo dey tok say na your papa do everytin for you, na im do DJ for you, all dat one, I no fit even address. Becos weda I dey do dis or dat, dem go still tok. I no fit change pipo mind, di only tin I fit change na wetin I dey do and na so I dey do am."" She also open up up about how pipo dey troll her for Twitter. Everyday dem (pipo) dey abuse me, I no care becos na dem get opinion. Wen I dey enta bed with my dogs Dudu and Funfun and we dey play, shey Twitter pipo dey for bed? Since I come back Lagos, I see say I get plenti supporters, and I dey call dem Cupcakes,"" na wetin she add put. DJ Cuppy dey known for her love for Pink. For her, di love start wen she enta di music industry. ""I tink e begin dey happun since I enta music industry, and see say I wan express myself through colours. Pink dey represent women but pipo no dey understand, pink no weak, e dey bold. She tok say many pipo no even like my hair (wey follow dey pink) but di artist tok say na her choice and how she like to express hersef. Although Cuppy start as DJ, she later chook hand for music. ""Plenti pipo ask why I wan dey do music, for me, I just do wetin I wan to do."" She tok say no be by force to listen to her music, as Nigeria get plenti artistes. ""Wen I start as DJ, I dey play pipo songs, I come tink say me too I wan make my own songs. I no tok say I be best singer bicos na very difficult job, I dey salute singers but I deserve to dey able to try."" She tok say she dey see plenti comments, some dey make her laff, odas go dey yab her but she tok say she no get problem at all. Di musician tok say she get two 'children' - two dog children, Dudu and Funfun. ""Pipo dey laugh me becos Dudu and Funfun turn one year old for 17 February, and I come sew cloth and do party. Some pipo dey laff but during covid pandemic, I dey house alone I no get anybodi. Na during dat time I build relationship wit dem (di dogs). I tink dem help wit my mental health and I come dey learn small-small how to be mother. I learn how to manage finance; dogs dey expensive, I dey Lagos now and dem dey for hotel, Na my grandmama give dem name, Dudu and Fufu - Dem be di joy of my life."" Cuppy recently celebrate her sister Teni wey just engage to her boyfriend of many years, musician Mr Eazi but she herself no dey relationship. ""Na so somehow I get Ibadan husband oh, I get one cupcake Lerry, e dey Tweet me since like four years - na so Valentine's day come me I no get boyfriend, na so I say oya Lerry make we do valentine date on Twitter na so e accept. In fact, I come Lagos and invite am come my grandmother birthday."" On why she still dey single, Cuppy say: ""I no know wetin I want, for now, I get degree for Oxford university to finish, I get BBC Radio1 Xtra show every Sunday, I get two dogs to take care of so my plate full. I no know but if e go happun e go happun."" Di DJ about lessons she dey learn as di daughter of billionaire businessman, Femi Otedola. ""Di good side be say everyday I dey learn sometin, na so dis morning I wake up by 8:00am my papa don reach office at 6:00am. My papa dey work so hard, and e dey remind me, say make nobodi get comfortable. She tok say di bad side dey too. ""Na so I DJ for my grandma party, dem no pay me,"" Cuppy tok as she laff." https://www.bbc.com/pidgin/media-61091814 +entertainment Ada Jesus comedy sickness: Wetin di popular comedian bin reveal about her illness "Nigerian comedian Ada Jesus wey her real name be Mmesoma Mercy Obi tok say she dey sick wit kidney problem. For interview wey she do wit BBC Igbo for February 2021, di Instagram sensation bin say e don reach almost one year wey she don dey battle di illness. ""E don tey wey dis sickness start to dey worry me. E don reach almost one year. E bin get some tins wey dem tell me to avoid but I no gree avoid dem. Di sickness dey make I dey sweat because of heat, den before you know, fever go begin worry me and my bodi go begin swell up. Wen e happun I dey go pharmacy go buy medicine. Nigerian comedian Ada Jesus tok say she dey sick wit kidney problem. Since December, my bodi dey swell up especially my belle and my face. I no dey fit waka because I no even get strength to stand up. Wen I go hospital dem tell me say wetin dey worry me na kidney problem say if money dey, dem suppose carry me go India go do transplant. Ada Jesus reveal say a lot of pipo don make donations and as at dat time, e remain small make di money reach for her to travel for di transplant. ""E dey like di sickness dey suck my blood. In fact, I dey take pints of blood at least three time every week. Dis tin don worry me too much. Na clean dem dey clean my bodi because I no fit baff. Abeg make everybody pray for me."" Na so she tok. But reports bin dey fly upandan say di comedian dey helpless wit di sickness because of di insults and di disrespect wey she give one so called witch doctor, Chi Marine Temple, Rita Edochie wey dey act movies for Nollywood and Prophet Chukwuemeka Ohanaemere, one controversial Nigerian pastor wey pipo know as, Odumeje, di president of Mountain of Holy Ghost Intervention and Deliverance Ministry inc. Chi Marine Temple and Rita Edochie don come out to say dem forgive her. But e no dey clear how di sickness take link to di pipo wey she allegedly offend." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56720561 +entertainment BBNaija: Why Cameroon Biggy237 no dey laik BBNaija Biggy 237, Cameroon Big Brother TV reality show, don enta number two week but fans di still tasty, di hungry for see some kana juicy gist weh e go make dem tok, deh di complain say de show no dey laik BBNaija. De only tin for Biggy mansion weh e go viral na de fire weh e bi catch kitchen and e give fans and kontri pipo toking point. But why pipo di complain say Biggy 237 no dey laik BBNaija? Biggy 237 no get excitement- no kissing, no hugging laik for BBNiaja, instead na prayer dem dey do. Some fans di hungry for see some lovigiaties-love stories inside de house, two pipo inside bedsheet, kissing, hugging laik for BBNaija. Some even say make deh change kissing rules. Even if some desires bi human, organisers check say e good for maintain moral standards. But, Biggy 237 di shine eye for dia house rules wit fans and public for mind and deh di hope say deh go fit satisfy fans dia wish. Biggy 237 house small house no be small. When deh compare BBNaija house, Biggy 237 mansion over small and pipo no di fit move inside free from weti deh di watch for video. Dis make Nigerian fans di ask if na by force for start reality show. But de mansion no ova small as such, as organisers di open oda areas. Wen deh open side for gym pipo surprise. Plans dey for go for dia own building from next edition. Organisers no chose correct time for show Biggy 237 for de same time wit BBNaija. Many fans say deh for no show Biggy 237 for de same taim wit BBNaija. BBNaija di overshadow e small broda. For de organisers, na Covid-19 bi make dem suspend dia show weh e for finish before now. Wusai Biggy 237 di show na de kweshion weh pipo continue for ask Biggy 237 no dey laik BBNiaja weh e di show for DSTV so pipo no know how for watch'am. Cameroon Big Brother di show na for My Media Prime and Biggy 237 TV but plenti pipo no fit watch. But some big tori don komot for Biggy house weh e fit change life for housemate. Popsy Brown e mami dey for Jamot hospital for treatment afta e show e picture wit doty clothes add say e head no correct. Some well-wishers donate moni take Posy Brown e maini go hospital. Real business di start dis week-end, mansion go hot as as four housemates go quit. https://www.bbc.com/pidgin/sport-53777064 +entertainment Why pipo dey drag Drake like small gen after album release "Drake don become di subject of online dragging following di release of im new album wey im call Her Loss. Di album na collaborative album wey Drake do with 21 Savage. Dis go be dia second collabo. For di album e follow use rhymes and tori to drag plenti pipo in di process. Among dem na Megan Thee Stallion and Serena Williams billionaire husband, Alexis Ohanian. US Rapper Megan Thee Stallion do beta clap back on top Drake head afta e make dis statement from one of di songs from di album wey im call Circo Loco. She catch di sub for di song wia im bin rap say ""lie 'bout getting shots, but she still a stallion"". Di 'Her' rapper hala for social media say ""since wen e don dey okay to joke about women wey dem shoot"". She further accuse Drake say e dey use am to chase clout, say ""I no say I dey very popular but stop to dey put my name for weak conspiracy theories for bars"". Oda pipo for social media don make di mata begin to trend for social media Megan Thee Stallion bin comot for 2020 to accuse anoda Canadian rapper Tory Lanez say e shoot am for leg afta one Hollywood party wey Kylie Jenner host. Di case dey go court from next week as oga Tory don already dey house arrest since last week. Pipo for twitter hey claim say Drake dey diss di famours rapper account off events as lies. For wetin many pipo dey call di best song of di album, Middle of the Ocean, Drake say ""Sidebar, Serena, your husband is a groupie"". Groupie na wetin dem dey call fans of celebrities wey dey follow dem up and down, in hopes say di celeb go knack dem. But Alexis Ohahian no fit di mould seeing as im marry di ogbonge former tennis star for 2017, and dem get one daughter togeda. However di Reddit Found sub Drake back on twitter as im sef call imself ""di best groupie for my wife and daughter"" Why Drake no clear why im put Serena name for di album, around di time di tennis star meet her husband for 2015, tori bin comot say di rapper bin dey date am. Although none of dem comot ot confam di tori. For di same Circo Loco song wia im beef, Megan Thee Stallion, Drake come for di rapper formerly known as Kanye West too. Shey you remember for 2021, wen Drake and Ye do concert togeda to quash dia long term beef, well Drake say no be because of Kanye west im do am. E tok for di song say, ""Linking with di opps, I did that for J. Prince"". J. Prince na di founder of Rap-A-Lot wey bin ginger di rappers to squash dia beef. B���ut contrary to normal Ye behaviour, e no come for di Canadian born rapper, for one tweet, di former presidential candidate, call for rappers to dey on one side, and end di tweet say, ""Love Drake"". Di last time di two collabo before di Larry Hoover concert na for 2016 before plenti gbas gbos enta di mata. Dis two grown men don use words take beef demselves like mad on top Twitter. E reach di top level during di 2018 beef between Pusha T wia Pusha reveal say Drake born pikin with one former porn star. Drake say na Kanye West tell Pusha as na im produce di song but Ye deny di claim. Ye just comot from one kasala wey cause many pipo to cancel am including brands wey bin dey collabo with him wey crash im net worth from billionaire to millionaire. Drake wey dey call imself Champagne Papi na ogbonge rapper wey enta into di spotlight worldwide with Lil Wayne, Young Money entertainment. Before den Drake wey im real name na Aubrey Graham bin act for one TV show wey dem call Degrassi for Canada. So far Drake don break plenti records in cluding Billboard most wins in one year for 2017, as im gbab 13 awards. E don also get plenti worldwide hits including One Dance wey e feature Nigerian Star Wizkid. Drake dey different from most of di rappers wey e follow come from on top say e dey follow sing as well as rap for im songs with songs like ""Better Find your loving"". With gbedu from Hotline Bling, God's Plan and In My Feeling, Drake don stamp im name as ogbonga pesin for di hip hop game." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd1n794dw1yo +entertainment YouTube: Videos wey Nigerians watch pass for 2019 YouTube don release di list of videos wey Nigerians watch pass for dis year 2019. Di channels wey get di top three most watched videos na Mark Angel Comedy, Sceneone TV and Supersport. According to Youtube, dis videos wey enta top three show say Nigerians like jolliment and sports well-well. Di 2019 list also show say Nigerians dey like go YouTube to watch news tori as di BBC Africa Eye tori about 'Sex for Grades' and Ynaija interview wit popular photographer, Busola Dakolo enta list of di top trending videos. 1. Mark Angel Comedy - 'Commander' (Episode 193) 2. Sceneone TV - Aiyetoro Town Episode 1 - 'Upgrade' 3. Supersport - UEFA Champions League | Liverpool vs Barcelona | Highlights 4. GhenGhenJokes - Interview (Atiku or Buhari) 5. Xploit Comedy - The Spirit of Stinginess 6. AyoAjewole Woliagba- YPM: 'Sunday to Remember' 7. Official Broda Shaggi - 'The Prophet' 8. Kyinkyinaa Twan Comedy - 'Am Professional Mechanic' 9. BBC News Africa - Sex for Grades: Undercover inside Nigerian and Ghanaian universities 10. Kenny Blaq - The African Praise Experience 2019 11. Big Brother Naija - Finale: And Mercy Wins 12. Splendid TV - Mad Over You Episode 4 13. RÉvsVEVO - Poco Dance tutorial - How To Do The Poco Dance 14. Chop Daily - How To Zanku Part 2 15. Ynaija - How I Met Pastor Biodun Fatoyinbo and The First Rape - Busola Dakolo | Part 1#With Chude YouTube also release di list of top trending music videos and Zlatan featuring Burna Boy - Killin Dem top di chart. 1. Zlatan x Burna Boy - Killin Dem 2. Davido x Chris Brown - Blow My Mind 3. Rudeboy - Reason With Me 4. Naira Marley x Zlatan - Am I A Yahoo Boy 5. Kizz Daniel - MADU 6. Naira Marley - Soapy 7. Teni - Uyo Meyo 8. Benson Ken - Is back with a Powerful Worship Medley - Talent Hunt 9. 9. Adekunle Gold x Simi - Promise 10. Rema - Dumebi 11. Rudeboy - Double Double ft. Olamide, Phyno 12. Fireboy DML - Jealous 13. Larry Gaaga x Wizkid - Low 14. Timaya - Balance 15. Teni - Power Rangers https://www.bbc.com/pidgin/50675331 +entertainment Obi Cubana EFCC: Obinna Iyiegbu wife Ebele, Cubana Chief Priest react to EFCC case "Obi Cubana wife Ebele Iyiegbu don react to im invite by Economic and Financial Crimes Commission [EFCC]. Na on Monday di businessman Obinna Iyiegbu, wey pipo sabi as Obi Cubana go EFCC - -Nigeria Economic Police - office by imsef. One source from di EFCC tell, BBC Pidgin say dem no arrest Obi Cubana as tori pipo bin report. And since wen Obi Cubana EFCC mata land, pipo don comot to react to di news. For one Instagram post Obi Cubana wife say ""I call am Nwachinemelu! Okpataozueora worldwide ❤️ ""One man wit heart of Diamond."" ""We love you and we dey solidly behind you. Even Jesus don go through worse than dis so no stress."" Ebele Iyiegbu add say: ""Di grace dey overwhelming and e dey overflowing. God imself na im raise you."" Again, I repeat…""Who God don bless, no man fit curse"" because im go turn everything around for good."" She add am say even if na na di good, di bad and di ugly, God go turn everytin around for am. Cubana Chiefpriest wey be Obi Cubana business manager don also chook mouth for di mata, im say ""Wetin no kill us dey make us stronger"", im add #freeCubana. Singer Davido also post Obi Cubana picture for im Instagram story for wetin be like support. Davido caption di picture ""Obi Nwere ego""- wey mean Obi wit di money Meanwhile, EFCC say ""We no arrest Obi Cubana."" ""We don bin invite am come our office two weeks ago and e show up just yesterday around 11: AM by imsef for our office wey dey Wuse Zone 6 Abuja,"" di source tok."" Di 46-year old business man, Obi Cubana na from Anambra state for eastern Nigeria and e dey into entertainment and hospitality business. Di source inside EFCC say dem dey investigate Obi Cubana for Evasion of Tax by di Cubana group. Oda charges wey dem dey torchlight di business man for na; Money Laundering and Abuse of di Naira in public places. E no dey clear if di abuse of di naira charges dey related to di spraying of money wey happun during di burial of di mama of Obi Cubana for July dis year. Di burial ceremony of Obi Cubana mama wey take place for im home town Oba, Anambra State bin make headlines and cause serious tok-tok for Nigeria social media platform. During dat period, some Nigerians come begin tok about di money spraying by guest for di event but Obi Cubana defend am by saying na di guest get dia money and so dem fit spend am anyway dem like. ""How I go plan make pipo troway money, carry am bath? Di money na dem get am… na dem get dia money na dem get dia style,"" Obi Cubana tell BBC Pidgin during one interview for July. ""Those pipo no be pipo wey I fit tell 'do dis or do dis'… but I feel say na love dem wan come show.""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59131612 +entertainment Iyabo Ojo, 'Nkechi Blessing', Jide Kosoko & 'Tampan' controversy for Yoruba movie industry "Di Yoruba movie industry for Nigeria dey experience one of dia biggest controversy. Kasala start since di arrest and bail of one of dia members, Omiyinka Olanrewaju aka Baba Ijesha. E involve di join body of actors and movie makers for Yoruba movie industry wey be Theater Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria, [Tampan]. Tapan bin announce say dem ban Iyabo Ojo and Nkechi Blessing sake of dia comments against di association. Di controversy increase after court grant N2million bail to Baba Ijesha wey bin dey face trial on top sexual assault. Dis one na after im plead say e no dey guilty of di charges against am for alleged defilement of minor. One Ikeja court inside Lagos, Nigeria commercial capital na im grant Baba Ijesha. ""As Tapan BoT members and elders of di industry for di Yoruba genre, we dare say to both Iyabo Ojo and Nkechi Blessing and odas like dem say... ""If una think sey una popularity no be through Yoruba sector of di Nigerian motion picture industry, make una at least realise say na di industry give una platform... ""Platform to become wetin una don become today,"" Jide Kosoko tok on behalf of di organization. Tampan na di join body of actors and movie makers for Yoruba movie industry wey be Theater Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria. Dem create Tampan for February, 2014, for Lagos state. South western Nigeria - dis na after quarrel happen for Association of Nigerian Theatre Arts Practitioners, ANTP. Di reason for di creation of Tampan na to protect di interest of dia members. Since di creation in 2014 record never show say Tampan don sanction any of dia members. For dia press briefing Tampan caution two Nollywood actors, Iyabo Ojo and Nkechi Blessing for dia comments about di group and dia reaction bail wey court grant Baba Ijesha. ""We particularly observe di continuous derogatory statements wey Iyabo Ojo make against di Association and di industry as a whole. ""Unfortunately, Nkechi Blessing don also join di verbal attack on di Association and by extension, di industry and we say enough is enough,"" Kosoko tok. Tori also come out say Tampan ban dia directors from working wit Ojo and Blessing - BBC Pidgin no fit confam di tori. But see as di actors Iyabo Ojo, Nkechi Blessing and dia supporters react to di tori;" https://www.bbc.com/pidgin/tori-57644304 +entertainment Big Brother Naija housemates eviction: Michael, Kayvee, JMK, Queen get in as Yerins, Niyi, Beatrice chop eviction "Yerins na first to chop eviction for Big Brother Naija reality show on Sunday. Also, Niyi chop eviction from di TV reality show on 8 August, 2021. E no end dia, Beatrice also suffer eviction from season 6. But first Michael na di new housemate wey go join di BBNaija Shine Ya Eyes house. No be only Michael, Biggie reveal more new housemates inside wetin be like new twist. Kayvee, Jumoke [JMK] and Queen na some of di newest housemates. Michael - BBNaija new housemate Preacher of love, but entertainer of drama Michael Chukwuebuka Ngene no like pretentious pipo. And e insist say you no go catch am fighting over girls, food, and chores inside di Big Brother Naija House. Michael bin relocate wit im family to United States for a while before e return to Abuja wia im mama dey live now. A self-confessed bad boy, 26-year-old photographer Kayvee say im different background go help am keep im head in di game. He dey ready to spice things up inside di House with im positive energy and im dance moves. grow up for Nigeria 23-year-old law graduate JMK [Jumoke Adedoyin] dey ready to spice things up in the House by being di life of the party. She grow up for Ilorin Kwara State say pipo go love her because she bring positive energy and mak pipo happy. Her strategy for this season? She say, No strategy! Queen-Mercy Okon Atang from Akwa Ibom State like to show off her ""sweet"" body and feel say clothes dey overrated. Dis happy girl and beauty queen, wey say she be politician and entrepreneur, plan to be nice to everyone inside Big Brother Naija House. But she say she no go waste time to ""bite"" wen someone step on her toes. She be 26-years-old graduate of Nnamdi Azikiwe University wey dey live for Lagos. Im be medical doctor wey say ""e like to eat even though e no dey show for im body"". E describe imsef as 'polymath' wey get undying love for many creative things. Dis former basketballer come from Oyo State and e don marry wit one pikin. Im also be businessman wey dey run fantasy game platform and event business for Cape Town, South Africa. Niyi dey 6'6'' in heigth and likely go be di tallest housemate on dis season edition of di show. Beatrice na fashion model wey come Port Harcourt, Rivers State. She also get clothing brand and afta di show she dey plan to improve on am and build a modelling agency She love to dance and she say she dey come di house wit lots of entertainment. Beatrice dey single." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58138166 +entertainment Simi and Adekunle Gold: Duduke love and life inside dia two years marriage "Simi and Adekunle Gold [Duduke] love and life inside dia two years marriage na gist about di two Nigerian singers/cele wey marry quietly for January 2019. From casting dia sef for social media to all di sweet love letters and di songs dem dey sing for each other, e be like say Adekunle Gold and Simi wantake di title of Nigeria ultimate couple goals. On Wednesday, di couple celebrate their second wedding anniversary wia new details of their relationship bin comot Simi reveal say dem don dey for togeda for seven years including the two years wey dem marry, while Adekunle Gold tok say im first meet am wia she dey perform and even buy new cloth for di event. Di couple bin keep dia relationship private till afta dia wedding wen dem go honeymoon come release ""By You"" togeda. Recently, di Kosoko couple start to dey cast each oda on top wetin dem bin dey do wen dem jam each oda, as Simi tok for one post ""Wen we bin meet, e bin still dey edit imself lapping Rihanna and co"". Simi tok for her anniversary message say she don dey with her husband fo seven years (since 2014) wey mean say dem bin dey date for 2016 wen Adekunle Gold release Orente wey im later reveal say na about Simi even as at dat time dem bin still dey form friendship. E comot for 2016, say na Simi mix and master im first studio album, Gold and e bin reveal for several interviews dem say na she inspire im genre of music choice. So far, di couple don release five songs wey dem sing togeda wey include ""No Forget, Promise, By You, Bites The Dust an Take Me Back."" However, di whine wey dem bin dey whine Nigerians say dem be just friends almost fall apart afta for Simi Lagos concert for December 2018, wen she kiss her then boyfriend for mouth. Dem marry for secret ceremonies for January 9, 2019 and no be until dem go honeymoon tori say true-true dem don turn husband and wife start to show face. As of now di parents of one, Adejare dey use di kain energy wey dem use hide dia relationship wen dem dey date to take tension pipo for social media. From cute videos with dia pikin to Adekunle Gold ""breastfeeding"" needs, even to how Simi wan turn agbero on top her pikin mata, dem don sow say love sweet die. For dia career, e be like married life don give dem more ginger, as Simi burst brain with hits like Duduke and Know You wey feature rapper, Ladipoe. From 2019, she don drop three new EPS, wey dme dey call Restless II, Awake and I'm Back Home and her third studio album, 'Omo Charlie Champagne Vol. I'. She also chook her hand for acting for di first time as she join di cast for Kunle Afolyan 2019 feem, Mokalik. Adekunle Gold too no slack for im career, as at now im hit single, AG Baby still dey hit for airwaves across di kontri. E also drop new album wey im call Afro Pop, Vol 1 wey show im music dey explore new styles. Adekunle Gold don sign different deals as brand ambassador to corporate brands for Nigeria afata im marry Simi." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55614849 +entertainment Aamir Khan: Bollywood star announce divorce wit Kiran Rao after 15 years "Bollywood superstar Aamir Khan and producer-director Kiran Rao don announce say dem dey separate after 15 years of marriage. Dem announce di move for inside joint statement say dem go continue to dey work togeda and raise dia pikin togeda. Dem tok for inside joint statement say, dem wan ""start new chapter for our lives wey we no go be husband and wife, but we for be co-parents, and family for ourselves."" Khan wey be 56 and Rao, 47 bin meet for 2001 and marry afta four years. No be Khan first marriage, as e bin marry Reena Dutta before and dem get two pikin togeda. Amir Khan don dey for dis movie industry for almost fifty years and dey for list among di most popular Bollywood stars. One of im most popular work, na di dramatic comedy, ""Three Idiots"" wey tok about some of di wahala wey dey school system bin gada am recognition world wide. But no be for only feem im voice don loud. For 2015, Khan wey be Muslim bin make headlines wen im hala against di intolerance for im religion for di kontri. E loud sotay e even get di negative attention of di ruling BJP party." https://www.bbc.com/pidgin/media-57705627 +entertainment Chidinma Ekile biography: Profile of 'Jehovah Overdo' singer, Nigerian musician wey switch to gospel music "Nigerian singer Chidinma Ekile announce big career switch on Sunday May 2, 2021 from secular music to gospel. Di singer wey many pipo dey call Ms. Kedike, announce di switch ontop her social media handle. Her announcement come wit di celebration of her 30th birthday and na for Instagram wey she share di informate to her 7.5 million followers. ""My name na minister Chidinma Ekile. I be crusader of di gospel of Jesus. I be crusader for di gospel of Jesus Christ."" Na so she tok for her Instagram post. Many of her fans hail her for di switch including some of famous friends wey drop comments for di post. Tiwa savage, Korode Bello post love emoji while Niyola write love it. Na for 2010 Chidinma blow, afta she win Project Fame West Africa. Den she be 19 years Old. Afta Project Fame, she release her debut single, 'Jankoliko' featuring veteran star, Sound Sultan. She later go on to sign for iLLBliss and Clarence Peters' record label, Capital Hill/Goretti Company wia she release di single wey she title 'Kedike.' She also release oda singles like 'Emi Ni Baller,' wey win Best Video for di 2014 Headies. For di 2012 edition of di KORA Awards, Chidinma win Best Female West African Act. She also collect nomination for Best Female Act for di 2014 MTV Africa Music Awards. Currently, Chidinma dey signed to Eezee Concepts - na di same record label wey sign Gospel superstar, Mercy Chinwo - where Chidinma release her new single, 'Jehova Overdo.' Di new 'Jehova Overdo' don get 227 thousand views on youtube. According to di label, Chidinma bin take break from Music and di public eye and she bin dey undergo a period of actively waiting on God and preparation for wetin dey ahead. Chidinma bin start her music career for church as she start from Church Choir from a young age and she bin dey serve as a music director for many years now. Her unveiling with EeZee Global Ministry na di beginning of greater tins ahead according to dem." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56968330 +entertainment "Zlatan and DJ Cuppy: “Go settle oh"" MC Jollof tell Zlatan about im beef wit Cuppy" "Di gbas-gbos between DJ Cuppy and musician Zlatan Ibile afta Cuppy claim say Zlatan block her for social media still dey raise dust for Nigerian entertainment industry. Some pipo inside di entertainment industry don chook mouth inside di beef between Zlatan and Cuppy. One of di pipo wey dey tok about dis mata na Nigerian comedian MC Jollof, im do video to advise Zlatan to settle im beef wit DJ Cuppy. For inside di video wey im release for Instagram ontop dis issue, Jollof say ""Davido Papa and Otedola dem na di same category na English dem dey speak, dem dey go abroad for every holiday, you, you know no dey go follow rich pipo"" na wetin Jollof tok ""You wey suppose dey kane line wit Cuppy you dey go dey quarrel, go settle oh, if you want make she give you 50 or 100 million for di fund raising"" na wetin im add put. Jollof also address DJ Cuppy inside di video, ""You Cuppy sef you just siddon press wetin dey worry you so if di boy no match you bill now normally you no suppose just use your church mind,"" na wetin Jollof tok ""Afta you go wear sneakers dey wash motor all dis rich man children abeg your problem sef make una get out."" MC jollof tok dis one afta Zlatan bin open up for di first time about di blocking mata wey DJ Cuppy accuse am of. When dem ask am about im relationship wit Cuppy for Soundcity 'TheSwitch' show, di rapper shock many pipo wen im claim say im no know who she be. ""She be artist?"" na wetin im tok. When dem ask am if him no know Cuppy, di rapper answer dem say ''I no know her.'' Tori be say few weeks ago, Cuppy tok say Zlatan block her for social media apps Whatsapp and Instagram for over 10 months. ""10 months later and I sometimes still dey wonder why @Zlatan_Ibile blocked me on WhatsApp and Instagram without saying why; we bin actually be friends...AND ""Gelato"" na hit song!"" na wetin she tweet. DJ Cuppy and Zlatan bin collabo do di song 'Gelato' way back for 2019." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55879489 +entertainment How to vote on BBNaija 2020 Every week, for Big Brother Naija Season 5, 2020, Biggie dey put up all housemates wey no win Head of House and deputy for eviction, meaning. E go come remain for fans of Nigeria biggest television reality series to decide who dem want make e stay and who dem want make e leave di house. So far, 6 housemates, Ka3na, Lilo, Tochi, Eric, Kaisha and Praise don comot di house afta dem get less votes from fans and housemates vote dem out Three possible ways dey for you to cast your vote and you dey free to choose di way wey easy pass for you. Di number three way to vote na to visit Africa Magic mobile site. Just cari ya fone, google Africa Magic, once you enta dia website you go find wia to vote. Pesin wey choose to vote through website fit vote reach 100 times. Voting through mobile site na FOC 9Free of Charge) but you go gatz pay for ya data. Anoda way you fit take vote for your favourite housemate na through di myDStv or myGOtv (dat na di ap of di organizers of di show, DSTV). Here sha, di number of vote wey you fit to cast na based on which subscription package you dey do. If na App you wan use, voting na free, but you go pay for data. You fit vote through text message or SMS. To vote through SMS, just type VOTE plus di name of di housemate as text message den send am to 32052. If you dey vote through SMS, you fit vote reach 100 times and dem go charge 30 Naira for each time you sen di text. Inside dis season 5, Biggie introduce some kain new tins unto how Sunday evictions go be. For dis Lockdown season, all housemates go dey up for eviction each week, except di Head of House and Deputy Head of House. Housemates go do live eviction every Sunday. For di very first show, na di housemates go choose who among dem go go home. Here, na turn by turn each housemate go take enta Diary Room to nominate one out of di four housemates wey get di lowest vote. Housemate wey dem nominate pass n aim dem go evict. https://www.bbc.com/pidgin/53574588 +entertainment Beyonce: Wetin Nigerians dey tok about di singer 'Black is King' new album "Beyonce don enta hot seat recently afta she release trailer of her new visual album ""Black is King"". Di album wey di singer say dem originally film for 'The Lion King' movie, na to honour black pipo. She bin announce di release of di album on June 28, 2020 inside long Instagram post wia she tok about di hardwork wey she do to produce am. But since di trailer drop, some Nigerians don dey share different opinion of di kain message di album dey send about Africa and many no like how di album dey showcase di continent. Dis Nigerian model for tweet say Beyonce dey like showcase African culture for her music but she no dey ever come Africa do tour. Omowamiwa believe say di video dey show Africa wey no dey even exist. See some oda tins wey pipo dey tok: E no too tey before Beyonce fans come rescue her from di callout, as dem tag di pipo wey dey critic di video 'haters'. See some di tweets from Beyonce supporters: Beyonce bin feature some Nigerian creatives like Nigerian creatives Ibra Ake, Daniel Obasi, KC Obiajulu, Logor and Dafe Oboro wey work on di Nigerian part of di film, while Ghanaian creatives like Joshua Kissi bin work on di Ghanaian part of di film." https://www.bbc.com/pidgin/53239052 +entertainment Rita Dominic: Fidelis Anosike and Rita Dominic traditional marriage- See fotos of how celebs turn up "Nollywood stars, friends and family turn up in style for di traditional marriage of actress Rita Dominic and media entrepreneur, Fidelis Anosike. Di traditional marriage rites take place for Rita Dominic home town, Aboh Mbaise, Imo State, South-East Nigeria. Popular Nollywood actress like; Ini Edo, Chioma Akpotha, Joke Silver, Chidi Mokeme, Uche Jumbo and many more odas show face to celebrate with Rita Dominic. Here na fotos of how celebs turn up in style to grace di occasion; Recently, oda Nollywood actress and actor don also marry aside from Rita Dominic. For December, 2021 Nigerian Actor Lateef Adedimeji wed im colleague for di movie industry actress Adebimpe Oyebade. Also, Nigerian actor Stan Nze, marry im fellow actor Blessing Jessica Obasi for October, 2021 Rita Dominic na multiple award-winning actress, producer, and Co-Founder of di Audrey Silva Company. She di youngest of four children, and dem born Rita into di Royal Waturuocha family of Aboh Mbaise, according to IMDB biography of Rita Dominic, Rita start to dey act for local television dramas for di age of 5 and graduate from di University of Port Harcourt with BA in Theatre Arts (Acting) before she join di Nigerian film industry for 1998. Since then, she don dey known for her ability to act different characters and continues to receive critical praise for her portrayal of iconic roles. Rita Dominic don act for plenti Nollywood films and don get plenti Awards and Nominations for her acting. Fidelis Anosike na di owner and publisher of Daily Times Newspaper, one of Nigeria popular local newspaper Im acquire di Newspaper for 2007 under di Folio Communications afta goment bin close di newspaper former ownership down sake of some gbese. Fidelis start Folio Communications at di age of 24 afta im graduate from University of Benin wia he study Creative Arts Im be di Chairman and Chief Executive Officer of Folio Communications Limited before e announce im resignation from di Company board for June dis year to make Mr. Aliu Akoshile di new Chairman of di company. He say Folio Communications Limited na conglomerate, wey im found at a very young age. '' I dey very proud of wetin we dey able to achieve which suppose be inspiration for young pipo,"" he tok wen e announce im resignation. Oda companies unda di Folio Communications conglomerate na: Folio Nigeria powered by CNN, di Daily Times Nigeria, Miss Nigeria, 1st October, Times Multimedia and Creative Africa Xchange (CAX). Fidelis bin once tok about im family say im papa na junior police officer wey die at age 52, leaving im uneducated mother to labour to train five boys and three girls." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61160110 +entertainment Naira Marley: EFCC present 'evidence' for fraud case against singer Naira Marley "Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don present more evidence for court against popular Nigerian singer, Azeez Fashola Aka Naira Marley. On Wednesday di anti-corruption police display before Federal High Court for Lagos, virtual projection of one Compact Disc (CD) with 51,933 pages analysis of di iPhone of di singer. EFCC project di virtual, through dia second witness, Augustine Anosike, one forensic analyst. Before today, di prosecutor, Rotimi Oyedepo bin tell di court during di last trial say di prosecution only print out hard copies of important portions of di exhibit for di case. E say full version of di total analysis dey for inside CD wey dem label exhibit F1. Di court come grant di prosecution leave to display di CD for projector, in order to show di proof according to di law. During di last trial for October 26, di witness bin narrate how different text messages and chats wey contain credit card details bin allegedly bin dey exchanged between Naira Marley and anoda recipient identified as Yadd. So wen trial resume on Wednesday, di witness, again re-testify wetin e don first tok and show visual spots of those testimonies for di screen of di projected CD. E show visual dispalys of di credit card numbers, chats, plus di incoming and outgoing SMS wey dey analyse from Naira Marley iPhone. Di witness typically identify di ""message trafficking"" between di singer number and di oda recipient. Afta plenti question and answers between di defence counsel and di witness, Justice Oweibo come adjourn di trial until Nov. 30, Dec. 13, and Dec. 14. Niara Marley wey sing di popular song: ""Am I a Yahoo Boy"" dey face 11 counts charge, wey involve conspiracy, possession of counterfeit credit cards and fraud. Di Economic and Financial Crimes Commission sama Naira Marley dis charges on May 14, 2019. According to di EFCC, e allegedly commit di offences on different dates between Nov. 26, 2018 and Dec.11, 2018 plus May 10, 2019. Di anti-corruption police allege say di defendant, dat na Naira Marley and im accomplices conspire to use different Access Bank ATM cards to defraud dia victims. Dey also allege say e use one bank credit card issue to anoda pesin in order to get fraudulent financial gains. Di EFCC also tok say di singer possess counterfeit credit cards wey belong to different pipo, with plan to defraud wey amount to theft. Di alleged offences go against di provisions of Sections 1 23 (1) (b), 27 (1) and 33(9) of Cyber Crime (Prohibition) Prevention Act, 2015. For May 20, 2019, EFCC come drag Naria Marley go court before Justice Nicholas Oweibo, but e plead not guilty. Di court bin grant am bail for di sum of two million naira, with two sureties in like sum while trial on di case continue." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59066312 +entertainment BBNaija 2020 housemates eviction: Eric and Tochi na di latest to comot - See dia big moments for di Big Brother Naija season 5 edition Eric and Tochi na di latest housemate to comot from di Big Brother Naija season 5 lockdown house afta like three weeks for di TV reality sieries. Like di last Sunday night eviction show, oda housemates also get chance to choose two of di four housemates wit di lowest votes wey dem go like make e comot from di house. Dis na heartbreak for di fans of di two housemates but eviction na one of di ogbonge highlights of di game. As dia journey to winning 85 million naira competition moni don end, see di big moments of di Eric and Tochi for di house. Eric na di third housemate to comot from di house one week afta im girlfriend Lilo chop eviction. Eric sabi do push up pass everybody for di house. Di moment Eric tell Big brother for diary room say im dey enjoy himself for di house, say dis na wetin im neva experience before fro im life. Di Big Brother season 5 fans no go quick forget di lovey-dovey couple wey no last long for di house. E go dey hard for fans to forget di man wit di red cap always on di groove and ever readi for di Saturday night turn-up. Tochi na di number 4 housemate to comot from di house. Fans no go quick forget im acting skills Tochi and im acting skills on stage for one of dia game nights. Lucy go be one of di housemates wey go miss Tochi pass. Di gist and di unending conversation between di two. Di yoga moments. One of Nengi and Tochi moments. Out of 20 housemates wey start di journey na 16 housemates remain for di Big Brother Naija house afta dis eviction. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53714208 +entertainment Juice Wrld: See wetin you need to sabi about di US rapper wey die for Chicago airport "US rapper Juice Wrld don die at di age of 21, authorities tok. Na celebrity news website TMZ, first report di musician death, medical authorities inside Illinois don confam di tori. Di Cook County Medical Examiner's Office say im die on Sunday. Di cause of death neva still dey known, di office tok. Di rapper, real name Jarad Anthony Higgins, dey very popular for im viral 2018 hit Lucid Dreams. Higgins, according to TMZ, die afta im suffer one seizure for Chicago Midway airport on Sunday morning. Chicago police tell BBC say one 21-year-old man bin suffer one medical emergency around 02:00 local time (09:00 Nigerian Time) and dem take am to hospital, where dem announce say im don die. Police don launch investigation into di death. Na 2018, di rapper blow wit im hit singles All Girls Are the Same and Lucid Dreams, wey reach number two for Billboard Hot 100 chart. Wit dat success, music fans and record lebels begin chook eye for im side. Dat same 2018, Interscope Records sign am, for deal wey big pass $3million dollrs (£2.2m). Im top di Billboard chart for 2019 wit im second album Death Race for Love. For one of im songs, Juice Wrld bin rap about how artist dem no dey live long, ""im say all di legends don finish"". Plenty pipo dey tok about im life for social media, many of dem dey write ""RIP Juice Wrld"" to pay dia respects. For inside tweet, British singer-songwriter Ellie Goulding, wey collabo with Juice Wrld for her 2019 single Hate Me, describe di rapper as ""sweet soul"" wey for ""go far"". Hip hip artist HaHa Davis write for Twitter: ""Heart broken @JuiceWorlddd I love you bro.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-50706382 +entertainment Peru remix: Ed Sheeran sing in Pidgin as Fireboy Peru remix come out "Di 'Peru' remix of Fireboy DML featuring Ed Sheeran wey fans all ova di world dey wait for since don finally come out today, Friday 24, December 2021. Fireboy DML wey be popular Nigerian musician share for im social media handle di new version (remix) of di song ""Peru,"" wey im collabo with Ed Sheeran and fans no fit hold dia joy. British singer, Ed Sheeran sing in one of West Africa local language - Pidgin - for di first time as e add im voice to di song 'Peru'. ""Wen you wan see, wen you wan see me... "" Ed Sheeran sing in Pidgin for di chorus of di song. E also go ahead to sing in Nigerian Yoruba language and English; ""Omoge no be so, girl you just capture my soul..."" Di Nigerian singer-songwriter, Fireboy DML bin release di original version of di 'Peru' hit single for July 2021. Later for late December, Ed Sheeran reveal for one interview say e dey do remix of 'Peru'' with Fireboy DML and video of two of dem singing di song come later go viral for social media. Dis no be di first time wey international artist dey collabo with Nigerian musicians to remix dia songs or do something new. Plenti International musicians don dey follow Nigerian artistes do remix or fresh song togeda. Justin Bieber don do wit Burna, David get some wit Chris brown, Tiwa Savage collabo do remix with Brandy, Wizkid get one wit Beyonce. Social media for Nigeria don full with reactions from fans about di new version of 'Peru' wey Fireboy feature Ed Sheeran. Adedamola Adefolahan, wey also dey known as Fireboy DML na afro-life musician, sign to YBNL Nation, one record label wey Nigerian rapper Olamide found. E dey infuse soul, RnB and kontri genres into im Afro-Sound. E also dey known for im song writing. Di Nigerian musician start to dey sing for very early age for churches and schools Fireboy dey known for im popular single ""Jealous"" wey make hit through out Nigeria. Aside from ""Jealous"", Fireboy also don release some oda songs wey don travel far like;" https://www.bbc.com/pidgin/tori-59778809 +entertainment Alcohol challenge: Stop dey pour yamayama for body - Joeboy beg fans Nigeria artist Joe Boy don beg fans stop to dey pour different yamayama on their bodies as dem dey vibe to di new song 'Alcohol' wey im just release. Di singer also warn say make stop dey swallow tinss wey no dey healthy just bicos dem dey feel di song. Di challenge wey bin start for TikTok don see many pipo use di music for background, as dem pour or drink shayo. Many pipo even Nigerian celebrities don key into dis challenge but wetin make Joeboy dey worry na because pipo no dey sip alcohol as di lyrics of di song, some come dey pour am for bodi. Some even carry di challenge far from alcohol to dey pour things wey no relate to am for body like hypo, oil, soap, soup, food and oda tins wey dey shocking. Dis challenge don provoke reactions from many quarters as some pipo no see am fun again. Dem feel say e don go too far. Nigeria new generation artist Joe Boy bin release di single 'Alcohol' for September 2021 and e advise pipo to drink responsibly as dem dey vibe to di song. But internet catch fire as pipo turn di song to challenge begin dey release video to portray di lyrics. Di lyrics of di song dey about how di singer dey use alcohol as way make im no reason bad things or go back to where im dey before but pipo don turn am around as dem dey pour di alcohol all over their body for di challenge. Some no even dey pour alcohol but different kains tins from disinfectants to bleach, wey don make di singer worry. Some videos show pipo wey use oil, food and oda strong substances as dem dey vibe to di song. Challenges like dis dey pop-up from time to time - like di crate challenge - and dem get different purposes. Some na to promote products, music or dance style or odas na just entertainment. Joseph Akinwale Akinfenwa-Donus wey im stage name na Joeboy na Nigerian singer and songwriter. Dem born am for May 21, 1997 for Lagos state, Nigeria and e get degree Human Resources from di University of Lagos. Artist and entrepreneur, Mr Eazi na im discover am for 2017. E don two albums and many singles, among di latest na 'Alcohol' wey dey trend for social media. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58864032 +entertainment TikTok go sanction unhealthy eating videos "TikTok don announce changes to dia community guidelines, wey dey aim to crack down on content wey dey promote ""disordered eating"". Dem go remove videos wey encourage over-exercising and short-term fasting. TikTok go also expand dia system wey fit detect and remove videos wey get adult nakedness, illegal activities or risk of di safety of small pikins. Di changes go reason matter wey politicians and regulators bin raise. Social media platforms bin don dey under serious check-check sake of how dem dey reason wellbeing and safety of younger users in recent months. Di UK goment don plan to introduce one new law - Di Online Safety Bill - wey go sama big fines to social media platforms wey no do enough to crack down on dangerous content. And di Chinese video app dey face questions in di US in October over platform safety. Senators for di hearings bin suggest say eating disorder content dey common on di platform. For September, TikTok bin report say about one billion pipo dey use di app every month. Dem say di 91 million video wey dem remove during di third quarter of 2021, 88% dey removed before viewers fit watch dem. As nasty ideology like misgendering, misogyny and content wey promote conversion therapies already dey banned , TikTok say dem now don add further clarity to dia community guidelines to make dis clearer. TikTok say dem don expand dia approach and go now target videos wey promote bigger disordered-eating content too. ""We know say pipo fit struggle wit unhealthy eating pattern and behaviour and make dem no get eating disorder diagnosis,"" di company say for post on dia website. ""Our aim na to confess more signs, like over-exercise or short-term fasting, wey dey common under signs wey pipo sabi as di one wey fit cause problem."" TikTok say dem dey also develop one system wey go sabi and control some kind content teenage users no go fit watch dem. Di company dey currently test ways wey go allow users to tag dia own content, depending on di age of di audience e dey aimed at. Di company go open cyber-incident monitoring and investigative response centres for Washington, Dublin and Singapore dis year. Di move na part of dia expanded effort to stop unauthorised access to TikTok content, accounts, systems and data." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60292301 +entertainment Erica Nlewedim and Laycon Big Brother Naija: Erica open up on Laycon genotype, as Dorothy, Nengi, Vee, Neo tok how dem feel say Olamilekan Agbelesebiobaas win BBNaija 2020 "Days afta dem crown Laycon as winner of di BBNaija lockdown edition, Erica post a video on her page to address di issue of Laycon genotype. Erica say she no sabi say Laycon na SC. For di video Erica also regret drinking too much for Biggie house (Scroll down to watch di video interview here). ""I don see a lot of pipo dey tok for internet say I know about Laycon genotype and I use am against am. I be very emotional pesin, e no get anytime wey I don ever use wetin anybody tell me against dem. Laycon neva tell me say im be SC, im sabi say im neva tell me dat, To me Laycon dey very fine and I bin dey under di influence of alcohol wen everything wey happun for di house happun."" Erica tok to address her fight wit Laycon for di house. On Tuesday, di top five contestants grant dia first interview wit di host of di BBNaija show, Ebuka, wia dem tok about dia dia times on di show, big moments and reveal some oda things about Laycon as di winner of di show. Nengi, Dorothy, Vee and Neo tok about Laycon winning di show. Nengi follow Ebuka tok say, she don see Laycon as di winner of di show tey-tey ""Maybe week 6, thereabout, I don no say na im go win, I tell Dorothy for bathroom say na im go win."" Wen Ebuka ask her wetin she see, Nengi say ""I feel say im get a lot of fans and during di party, I see say dem dey hail am and I get strong instinct."" Nengi add am say she like Laycon kind of pesin, say im dey really caring. Vee say she bin dey expect to be di first pesin to dey evicted out of di top five housemates. Before di eviction show, Vee wey be close friend wit Laycon for di house don already tell Big brother say if she no get di chance to win di show, she see Laycn as di winner of di show. So e no come as surprise to her to see Laycon winning di show. Neo say im bin dey disappointed say im no win di show but wen im realise say na Laycon win am im dey happy. ""I no go lie, I bin think about di money, but wen I come hear say na my guy win di money , dat thing change, na double happiness for me."" Neo tok for im interview wit Ebuka. Dorothy say she bin see herself win di show after dem evict Vee, Neo and Nengi and e remain only her and Laycon But she say she no dey disappointed say she no win di show. ""I bin think say na Neo go win di money sake of im energy for di house and I bin judge based on di previous editions of di show."" she tok. Dorothy no expect say Laycon go win but she no dey disappointed say she no win." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54336672 +entertainment Fireboy DML album make pipo do wow! "Nigerian artiste Adedamola Adefolahan wey pipo sabi as Fireboy DML cause commotion ontop twitter with di release of im first album Laughter, Tears and Goosebumps on Friday, November 29, 2019. Di young musician first make im mark with im song 'Jealous' wey release for 2018. Na on October 16, 2018, Nigerian rap superstar, Olamide sign di ""afrolife"" singer to im record label, YBNL. Since di song land, pipo don enta social media to tok dia mind. Since di song drop, pipo don also begin compare Fireboy, Joe boy and Rema, three young musicians wey dey currently make waves for Nigeria music space." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50597826 +entertainment Events and activities Davido don cancel dis November "Nigerian superstar music artiste, David Adeleke aka, Davido don cancel many public appearances since di tragic death of im son, Ifeanyi. As at now, di 'Stand Strong' singer neva comot for social media since di beginning of November. Pipo neva see am for public. On im 30th birthday wey be significant age, Davido remian silent and unseen. Fans bin reveal how much dem miss am as e turn 30 years old on di 21st of November. Before in lose im son, Davido bin reveal for Twitter say ""November na month of blessings and change"". Na month wey im hit 30 years of age and im bin don plan better birthday for im sef. E also announce oda tins wey im bin dey plan for di month. As tins be now, e don reach three things wey Davido don postpone. Di festival wey suppose happun on on di 18th of November for Atlanta, Georgia. Di show suppose feature Kizz Daniel, Oxlade, Adekunle Gold, Victony among plenti odas. On di 9th of November, di festival organisers announce say dem dey move di show by one year sake of say, ""e dey necessary for Davido to spend time with im family and loved ones"". Davido bin sign as di PUMA ambassador for December 2021 and tori be say e be Nigeria first ever global ambassador. Since October, Davido don dey tease pipo with wetin e bin dey plan with Puma. Howeva, di sportwear brand announce say dem go postpone di launch of dia collabo till next year. According to dia statement, e mean say any pre-order fit dey fulfilled next year, or di pipo wey wan collect dia money go fit collect back. Fans no hear pim from Davido on di 21st of November wen di FEM musician enta di third decade of im life. E bin dey plan to mark am big according to tori. Dis na even as some pipo bin dey expect am to kontinu di tradition e bin start dis time last year. For 2021, e bin ask im fellow celeb friends to send am money to clear market - e gada about N200m and carry di whole money plus im own 50m give orphanages dem. Despite im silence plenti pipo comot to wish am happy birthday including Nigeria former Senate President, Bukola Saraki and im first daughter, Imade Adeleke among odas. Less than a week to di inauguration of Ademola Adeleke as di govnor of Osun State, e neva clear weda Davido go show face or perform for im inauguration. E bin play very active role of im uncle campaign wey include attending rallies, and also become very vocal for im ucle on social media. Many pipo see am as im launch to di political space. E bin tell BBC Pidgin afta im win di election say im support im uncle becos ""family na evri tin""." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cg385ng34gvo +entertainment Rock n Roll Hall of fame nominations: Fela Kuti, Mary J. Blige get nomination for Rock and Roll Hall of Fame Nigerian Afrobeats Legend, Fela Anikulapo Kuti don receive nomination to dey part of di Rock and Roll Hall of Fame. Di joinbodi wey dey run a museum to celebrate music announce dis one from dia list of nominees for dia social media on Wednesday. According to tori, dis go be di most diverse group of nominations for di Rock Hall history as out of di 16 acts dem bin nominate, seven of dem get women inside. Previous inductees,, include Janet Jackson and Whitney Houston wey get di induction afta she die for 2020. If Fela Kuti get inducted, im go be di first Nigerian wey go enta di Rock and Roll Hall of Fame. Dii oda nominees for di list include: Di Hall of Fame say dem go announce di inductees into di hall of fame by May, 2021. To dey eligible for nomination, di artist first commercial record, go ned to di comot at least 25 years before di year of nomination. Dem dey pick nominees by sending ballots to one international voting bodi wey get mor than 1,000 artists, historians, and members of di music community. Dem dey check di artist influence for oda musicians, how long and how far in career reach and di actual body of work. Fela Kuti na di musician wey dey credited for di creation and promotion of Afrobeat music from Nigeria. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56013743 +entertainment Big Brother Naija Season 5 housemates names: Rebecca 'Neng'i Hampson, BBNaija Head of House na im fans dey drag, see lockdown contestants events dis weekend Fans of di Big Brother Naija show season 5 lockdown edition don enter social media to debate, Rebecca Hampson AKA Nengi actions for di house on Thursday night. Nengi na di first Head of House for di ongoing 2020 Big Brother Naija reality TV show. Di Balyelsa State born housemate for di kitchen area of di house on Thursday night dey hug, lean on a fellow housemate, Ozoemena, in di kain manner wey be like say she dey express a special likeness for di guy. She also lose some points during question session wen she help answer question wey Big Brother ask Ozo. E be like say fans dey disappointed about her showing interest in a man, instead of di other way round. but some fans also support her action. Rebecca Hampson na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures. She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef. Friday night na game show wen Big brother go make di contestants play some games, e neva dey clear which game dem go play tonight but wetin we sabi be say: Pipo go lose points Some pipo get opportunity to stay longer for di house if dem win. And eviction fit happun (di surprise na wetin dey always characterise di Big Brother show) Social life na great part of Big Brother Naija, Dis Saturday night, housemates go get one club like party, dem go dress like party rockers and life DJ go dey di house wey go thrill dem wit good music. Big Brother neva unveil who go be di ogbonge DJ for di house dis weekend but we go dey update una. Wetin we sabi be say, e dey expected say housemates go unwine on Saturday night and romance na one of di atrributes wey we go fit confam between housemates wey dey involved wit each oda. Dis na anoda emotional moment for di house. In di morning of every Sunday atleast one housemate go comot for di house. Who go comot? Di Friday night game, Saturday party and activities wey don happun during di week and audience votes go determine who go be di first pesin to comot from di house dis Sunday. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53523712 +entertainment DJ Cuppy: Davido PA 'Israel DMW' beg Otedola for [DJ Cuppy and Zlatan] issue e put mouth "Davido personal logistics manager, Afeare Israel popularly known as Israel DMW don apologize to Florence Ifeoluwa Otedola AKA DJ Cuppy afta im bin put mouth for Zlatan and DJ Cuppy gbas-gbos recently. Afeare Israel bin tok say di Gelato crooner bin dey use Zlatan head afta DJ Cuppy post for Twitter say Zlatan block her for WhatsApp and Instagram and she no know why. DJ Cuppy later break silence on top di accuse say she dey owe artist money for di recording of one of her Hit single, Gelato. Latest tori be say Israel do video on Thursday post for im IG page beg DJ Cuppy say make she no vex and say wetin im tok na just tok im hear from pipo. Isreal add say e dey very sorry and make DJ Cuppy try consider say dem don be friends for long. ""I dey sorry for di embarrassment I cause you and your pesin, abeg no vex, wetin I tok na wetin I just hear, abeg no vex, me and you and your papa we don be friends, abeg no vex for wetin I do. I promise e no go ever happun again. Thank you very much."" She then post for her Instagram page on 1 February to address di mata say she no break any of her contract agreements regarding di recording of her song 'Gelato' as confamed by her lawyers. ""However, as IsrealDMW publicly and inaccurately tok say I dey owe artist money, I dey sue am for libel and defamation"". She conclude di IG post say ""See you in court Isreal"". Israel enta im insta story to address di mata, e accuse di Cuppy say she no give Zlatan any money from di hit song Gelato. Im call her fake friend, Israel also hail Zlatan for disposing DJ Cuppy as quickly as possible. For one interview Zlatan Ibile respond to di tok tok say im no sabi who DJ Cuppy be even as im confuse her name wit actress Cossy." https://www.bbc.com/pidgin/world-56033350 +entertainment Sean Chukwuemeka: 'Why I marry my 56-year-old love' Sean Imonioro Chukwuemeka love tori and wedding with im wife make headlines because of dia age difference. For dis interview with BBC Pidgin, 26-year-old Chukwuemeka open up about how im meet im 56-year-old wife, dia journey and wetin dey ginger dem. https://www.bbc.com/pidgin/media-59622412 +entertainment Rock & Roll Hall of fame: Nigerians para as Fela fail to make di 2021 Rock & Roll inductees list "Nigeria afro beat legend Fela Anikulapo Kuti no dey among di nominees wey dem go induct into di 2021 Rock & Roll Hall of Fame. For February 10 dis year di Rock Hall voting bodi list nominees from all over di world as potential inductees as dem open am for different categories - rap, pop, R&B, metal and Afrobeat. Di organizers list Fela among oda top musicians wey don make dia mark for international music scene and wey don release albums wey don last up to 25 years. Di total number of di nominees na sixteen wit seven of dem wey be females. Dem also open voting for fans to vote dia favourite nominees into di Hall of fame. But as dem announce di names of di nominees wey dem go induct Fela name no follow. Di 36th Annual Rock & Roll Hall of Fame induction ceremony go hold on Saturday, October 30, 2021 for Ohio, USA. ""Dis diverse class of talented Inductees reflect di Rock Hall ongoing commitment to honor artists wey dia music create di sound of youth culture"", tok John Sykes, Chairman of di Rock & Roll Hall of Fame Foundation for statement wey dem publish for dia website. For di announcement, eight-time Grammy awards winner and ""Queen of Rock 'n' Roll"" Tina Turner, American Rapper Jay Z, Todd Rundgren, The Go-Go's and Fof Fighters be di five ogbonge musicians wey dem select as inductees for di 2021 clas of Rock & Roll Hall of Fame. A look at di voting board result show say Fela na im come second but organiser say dem tally dis result wit odas before dem reach di final selection process wey dem use choose di 2021 Inductees. Di result wey dey show for di voting board fit be di reason why some Nigerians no dey happy say Fela name no dey among di top 5 musicians wey dem go induct. Di organizers say dem tally dis result wit odas before dem reach di final selection process wey dem use choose di 2021 Inductees. Femi Anikulapo Kuti, Fela son don dey busy dey calm supporters down say make dem no over react." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57090514 +entertainment Jim Iyke and Uche Maduagwu: Actor Uche Maduagwu challenge Jim Iyke a week afta dia fight "E be like sey pipo never see di last of di gbas-gbos between Nollywood actors Uche Maduagwu and Jim Iyke. Dis na as Maduagwu still dey demand explanation about di source of wealth of Jim Iyke. Less dan one week ago Iyke bin go challenge Maduagwu for im office - on August 24, one viral video show wen Iyke confront Maduagwu face to face. Since dat incident happen e show sey di controversial actor no forget di matter. However, many critics of di video say na promo skit between di two Nollywood actors. Six days afta, Maduagwu go one Lagos Cinema go challenge Jim Iyke again about im source of wealth. Di cinema na wia Iyke just premier im new movie ""Bad Comment"". Di movie na about social media abuse. ""Wia you see N100million wey you use produce di movie"", na question wey Maduagwu throw give Jim Iyke. Di actor pose di challenge on top Instagram wit video. ""I come di cinema because dem talk say you go come dia today but Jim run when e hear say Uche dey around. Person spend 100 million naira for one movie; which kain work e dey dey do. ""You come my office, you come beat me up. I dey here, check me out. I dey here, I dey here. ""Dem tell me sey you go come here today Jim Iyke. Dis feem cost N100m; N100m nah im you take do do dis feem. Wia you get your money? How did you get di money? For dis latest gbas-gbos some pipo dey feel say Uche dey prank pipo. But dat na wetin BBC Pidgin never fit verify at di time of dis report. On August 24, one viral video show wen Iyke confront Maduagwu face to face. Di confrontation na over one comments wey Maduagwu make about Iyke on social media. From di video, e show say Iyke manage to trace Maduagwu to e location. Dis na afta Maduagwu question di source of Jim Iyke wealth for one of e post for Instagram. But dis no be di first time wey Uche Maduagwu dey drag celebrities out for social media. Uche Maduagwu dey known for speaking on controversial issues and dis don make some pipo like and dislike am. E also dey know as di 'Red bra guy' sake of im signature red bra. For im Instagram page wey dey verify with more than 90k followers, Uche write for e bio say; E be Actor, Content Creator, Singer, Brand Influencer and Comedian. Dem born Uche Maduagwu for Amambra, South-East Nigeria according to infomate from multiple sources. But di actor no ever don post pictures of im parent or siblings for social media. Even though Uche don get di celebrity status sake of di controversial issues wey e dey chook mouth, e still keep e private life away from social media. Pipo no know if e don marry, who e dey date or if e get children. During one interview with LITV for 2017, Uche Maduagwu tok say e start im career as a singer wen dem ask am wetin make am go into acting. E say im feel say starting as singer go make am popular but God get better plan for am. PS: We don update dis tori." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58398597 +entertainment Nkechi Blessing marriage: Nigerian celebs Nkechi Blessing, Tonto Dikeh, Kora Obidi relationship palava "Nigerian actor Nkechi Blessing na di latest celebrity to say her relationship wit Falegan Opeyemi David get palava. Nkechi Blessing husband, Falegan Opeyemi David take to social media to say make dem no call am husband again. Di actor come do Instagram live to announce di news of di collapse of dia relationship. Now fans of di couple still dey in shock about di news of dia break up. Dis latest celebrity breakup dey come few weeks afta Kora Obidi, anoda Nigerian celebrity, wey announce say her marriage too don end. Our story go torchlight di odas wey just happun recently too. Nkechi and Falegan bin marry for 2020 but na for June 2021 di actress post pictures of dia wedding. And before di relationship scatter di former couple bin dey tortori dia fans wella for social media wit dia love. For one of dia post for Instagram wey bin go viral di actress bin dey lick her bobo toes. She even tease am small say e get ""woman leg"". Dia marriage wey dey almost two years, don come face palava for April 2022. Tori be say na her former bobo oga Falegan first torchlight di mata for im Instagram live wia im tok say ""I no be anybody husband"". Before di actress come out to her two point three million Instagram followers to share her own side of di story. Nkechi hala say na she first comot hand for di relationship since last year. And no be im leave am. ""You no fit date and Nkechi leave, I go leave you when I ready or I go leave you wen I do tire,"" she tok. Korra Odidi, US based Nigerian dancer and her ex husband Justin Dean love relationship na another one wey don pafuka. Tori be say di couple bin meet for China through one popular dating app, Tinder. Dem do dia wedding for December 2017 and dia marriage crash for March 2022. Kora former lover bin announce say im dey file for divorce barely one week afta dem welcome dia second child. Her former bobo explain im reason for di divorce as alleged cheating and add say di marriage dey uncomfortable for am. Dat news surprise many as di couple been no show any sign say dem dey get issues for dia relationship at all. Na for July 2021, di actress officially confam say she dey in a relationship wit Prince Kpokpogri. Di Nollywood actor tag Prince Kpokpogri inside social media post where she dey count her blessings and also refer to am as her 'husband'. She say ""I ADORE YOU @kpokpogri @kingandre_dikeh and all our kids. Thank you to MY HUSBAND."" For di video she post for her verified Instagram handle, e show her and Prince Kpokpogiri for di graduation ceremony of her son, King Andre, di son she get wit her ex-husband Churchill Olakunle. Tonto Dike write say God don answer one of her secret prayers as e give her man wey stand wit her as her head and as a father to her son. She thank God for her new status as she declare say if ""happiness na pesin, e for be her."" But dia relationship no last long sake of accuse of cheating wey make dem break up. Some see dis Nigerian celebs as role models and bin believe say all di love nwantiti dem bin dey play for social media mean say evritin dey okay. One fan say before Korra Obidi marriage wit her bobo crash, she bin dey pray for her own to be like dia own. But di fan dey so dis appointed. Marriage na big deal for Nigeria, dat na why many pipo dey interested in di love relationships of celebrities. Dem dey look up to celebs as role models and most times wan copy how dey live dia lives. Wit huge fans base, money and di pressure to keep up wit di trends. Some celebs say these these don lead to di collapse of some of dia love relationships." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61027902 +entertainment Is Rema dead?: Divine Ikubor aka Rema never die, na fake news dey fly upandan - Rema Manager "Abeg no mind tori wey dey fly upandan say Mevin record last born and fast rising singer Divine Ikubor aka Rema die on February 1, 2020 , becos na fake news! Dis na wetin di singer manager Sean Okeke tell BBC Pidgin find out on Saturday evening. ""Rema no die o - na pesin hack wikipedia page put dat fake informate."" Okeke tell BBC News Pidgin on Saturday evening say dem don correct di tori for im Wikipedia page. ""Wen Rema see di tori, all of us begin laff"" im manager add. Born on 1 May 2000 (age 19 years), di Nigerian musician wey be singer and rapper sign record deal wit Jonzing World, we be part of Mavin Records for 2019. Im rise to fame wit di release of di song ""Dumebi"" and ""Iron Man"", wey appear on Barack Obama's 2019 summer playlist." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51344198 +entertainment Why I dey dance with women for ‘Gidan Gala’ inside viral video - Tahir Fagge "For pipo wey sabi northern Nigeria movie industry Kannywood, di name Tahir Fagge go surely dey familiar as e no only be one of di pioneers of di industry but one of di most respected as well. In fact, some pipo dey call am di ‘Pete Edochie’ of Kannywood because of im no nonsense style for movies. So e come as a shock to many pipo across northern Nigeria afta dem see am dey dance with women for Hausa dance club wey dem dey call ‘Gidan Gala’ Many pipo for social media say dem dey surprised while some abuse am and odas pray for am saying maybe something like juju don happun to am. But for interview with BBC Hausa, di man imself don clear di air saying e forgive pipo wey dey abuse am because dem see am dey dance. E add say pipo suppose understand im situation before dem go start criticise or abuse pesin for wetin dem no know. “Pipo wey dey abuse me because dem see me dey dance I forgive dem even in di presence of God I no go like make I get case with dem.” But wetin dem no understand be say I don dey sick for sometime now, I get heart problem and di owners of dis Gidan Gala (Hausa dance club) come meet me say dem wan invite me to dia opening as a special guest. Dem carry N150,000 give me wey sweet my belle and afta I reach dia siddon, dem come play one old song and I come decide to show dem how to dance am.” E tok. “Dis na wetin happun but some pipo no seek explanation before dem decide to dey abuse and criticise."" Tahir say e don go see some of im colleagues over im issue and some of dem give am wetin dem deem fit. “Singer Rarara give me N20,000, Abubakar Maishadda give me N15,000 while Daddy Hikima dat one na God go bless am for wetin e dey do for me. I dey also call actress Aisha Humaira for helep wen di need arise.” Tahir Fagge na one of di pioneers of Kannywood and dey act now for over 30 years for di industry. E don appear for several movies including hits like ‘Soyayyar Facebook’ and ‘Abdulmalik’ and presently dey involve with Ali Nuhu series ‘Alaqa’ wey dem dey shoot for Kano state. Tahir dey married and get three children, e bin marry anoda wife but later divorce her. Di Kano state indigene bin work for goment many years ago before e retire to concentrate on im acting career. “I first start acting in di 1970s wen we form one group wey dey do community work, na from dia, we decide to create acting unit, so na from dia.” Tahir tok for interview. One of di major issues di movie industry dey face na lack of beta earning for di actors wey dey lead. Many dey struggle to cater for dia needs. Months ago, popular actress Ladin Chima wey dey play mother roles comot to tok how much she dey earn per feem, e cause plenty reactions at di time as shock catch many pipo. “Since I start to act up till now, I neva collect big money, sometimes N5,000 or less even today I comot go act movie and wetin I get na just N2,000. Na inside dat money I dey feed eight pipo wey dey depend on me for food."" She tok. Di Katsina born actress say she almost go homeless recently because dem tell her to vacate di house wey she dey live and she no get any oda plan. “I bin work for goment for sometime as a staff of Nasarawa hospital and afta I retire, I leave di quarters for dem so dat tin almost make me homeless. Di reason na say di money wey I dey make from acting too small for me to save to build my own house, how I wan begin save N2,000 to build house. Some ogas for Kannywood react to wetin di actress tok and say on dia part, dem dey pay her reasonably well anytime she act for dem. Ali Nuhu wey be di most popular actor/producer for di industry tell BBC say e dey wrong of Ladin Chima to generalise wen she know say no be all producers dey treat her poorly. “Wetin she tok dey wrong because no be every producer dey like dat in my own case she act movie for me recently and I pay her N40,000 for her services. Wetin she yan cause some pipo to dey abuse because she act film for me recently.” Anoda top producer Falalu Dorayi say wetin Ladin Chima tok surprise am because e don act several movies with her and neva for once pay her less dan N20,000. “In fact, she act for me less dan 10 days ago and wetin I give her na N30,000 so wetin she tok surprise me. “Even for my series feem she act five scenes and I give her N40,000 and wen her home wahala start, Kannywood pipo contribute almost a million naira for her.”" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp94104mzpwo +entertainment "Davido FEM lyrics: Nigerian singer latest song ""FEM"" na for pipo wey dey 'para' for am - Download full lyrics & video of David Adeleke new single here" "Nigerian singer Davido get advise to ""FEM"" for pipo wey dey 'para' for am anyhow wit im latest single. Davido wey real name na David Adedeji Adeleke title di new track wey im drop around 7pm on Thursday, September 10 ""FEM"" a Yoruba word wey mean ""shut up"" for oyibo. Di 27 year old Nigerian singer and song-writer announce di new single for im social media wia im write say; ""To di pipo wey dey tok about you because dem no understand your shine, dem no understand your grace, dem no understand why dem neva fit be wetin you be or get wetin you get..we say FEM!"" Some section of local media dey report say Davido fit don use dis new single title to yab alias diss anoda ogbonge Nigerian singer, sake of some of di words inside FEM lyrics: ""E be like you don dey tok too much, small tok you don dey tok tok, fem. O boy, you don dey do too much, small tok you don dey look who tok, fem…"" ""Pesin wey dey find pity, no dey do me itty bitty. You wan know 30 BG, you go know 30 GB wen you see 30 BG…"" ""Then Odogwu say we 'Like To Party' just call me...:"" For middle of August 2020, Davido make video for ""FEM"" song and a part of di video im shoot land ontop social media. At di time wen e drop, pipo bin think say song title go be 'Para.' Dis single na part of Davido upcoming album #ABT (A Better Time). [Intro] Napji killing dis one Baddest Para, ahah [Verse 1] E be like you don dey tok too much Small tok you don dey talk who talk Fem (Baddest) Oboy you don dey do too much Small tok you don dey look who tok Fem (Ah di baddest) Person wey dey find di pitty Omo no dey give me itty bitty Just call me, you wan know 30BG You go know 30BG when you see 30BG (Uh uh uh) You wey dey find the pitty Tell odogwu say we like to party Just call me, you wan know 30BG You go know 30BG when you see 30BG [Pre-Chorus] Uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh Make una tell am to call me Uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh [Chorus] Why dem com dey para, para, para? Para for me Why everybodi com dey para, para, para? Para for me Why dem com dey para, para, para? Para for me Na why 30BG wе go para, para, para Dem go para for you [Verse 2] Before di, before di matter get serious Before di whole matter gets dangerous You need to make sure you don't say too much 'Cause if you say too much, I fit to run up on you You see seh I get fans wey dey para gan You see seh my own G pass G-Wagon My nigga, I set trends, no Twitter, star I get men, I no dey gather boys I dey live my life, man dey turn am to shoot on sight Wen be say na me dey give dem life Dem go tell me who dey give them mind, give them mind Live my life, man dey turn am to shoot on sight Wen be say na me dey give them life Dem go tell me who dey give them mind, give them mind [Pre-Chorus] Uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh Make una tell am to call me Uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh, uh [Chorus] Why dem com dey para, para, para? Para for me Why everybodi com dey para, para, para? Para for you Para, para, para Para for you [Outro] Napji killing dis one Click here to download FEM by Davido" https://www.bbc.com/pidgin/media-54111139 +entertainment Pedro Linares López: Google launch new Doodle honour dis Mexican papier-mâché artist Google launch new Doodle to celebrate Mexican artist, Pedro Linares López on wetin suppose be im 115th birthday. Di home page of di search engine get one colorful dragon designed by Doodler Emily Barrera, based on di work of López. Dem born Lopez on 29 June for Mexico, in 1906 E learn im art skills of papier-mâché from im papa wey also be papier-mâché sculptor. Di artist become very sick for 1945 and he tok say im be dey see some fantastical mythical creaturesfor im fever dream. López begin use di fever dream as inspiration for im sculptures and make colorful pieces based on reptiles, insects, birds and mammals. Im begin gain international fame afta di release of one 1975 documentary about him by filmmaker Judith Bronowski. Dem later honor am wit later honored wit di first Mexican National Prize for Arts and Sciences for di category of Popular Art and Traditions in 1990. Oda fun facts about Pedro Linares López E dey most popular for two genres—di alebrije (fantastic animal) and di Calavera (animated skeleton) As im papa train am, im also train im three sons —Enrique, Felipe, and Miguel—di art of Papier Matche and dem expand di innovation Pedro Linares López bin tok wetin im see for im ‘fever dream’ say wen im dey for bed, im dream of a strange place wey look like a forest. E see trees, animals, clouds, sky, rocks, and so forth; e no feel any pain and im dey exceptionally glad walking down there. E see rocks, clouds, and animals transform into peculiar animals; Pedro Linares see donkey wit butterfly wings, plus rooster wit bull horns, a lion wey get eagle head, and dem dey shout di word: “Alebrijes.” Every creature dey shout louder and louder: “Alebrijes, Alebrijes, Alebrijes!”. Di sound become loud and im no fit stay dia again. E later catch headache and run along a stone street wia im see one man dey waka Afta Pedro Linares López sickness died down, Linares gave life to im vision, and di art of making alebrijes was born. Im bin want make im family and everybody think about di creatures wey im see for for im dreams by taking a piece of paper and molding di figurines wey dey im memory At a point im begin paint dem like im see dem for im dreams Afta dis event, Pedro Linares bin go through life showing his works to many pipo wey im meet Lopez don gain so many achievement and recognition , sotee dem invite am to di United States and Europe, wit sole motivation behind showing di world his works, his wonderful and unusual animals. Pedro Linares López gbab di National Arts and Science award for di Popular and Traditional Arts category for 1990, di highest decoration to artisans awarded by di Mexican Government. Afta two years, Pedro Linares López die on 25 January 1992 at 85 years old. Pedro Linares López three children and later grandchildren keep di Linares name synonymous wit di refined art of cartonería. And dem continue dey produce Alebrijes for different workshops across Mexico. https://www.bbc.com/pidgin/world-57655740 +entertainment United Nations: 'Tonto Dikeh Ambassador award no get anything to do wit United Nations and e dey illegal' "United nations don react to Nigerian celebrity, Tonto Dike 'United Nations Noble International Ambassador for di United Nations Rescue Services award. Nigerian actress, Tonto Dike bin recently announce her honour as di United Nations Noble International Ambassador for di United Nations Rescue Services on Wednesday, 7th March, 2021. Dis announcement don raise questions whether dis honorary ambassadorial awards/appointment dey come from di United Nations or whether e even dey real? Director of United Nations Information Centre for Nigeria, Ronald Kayanja confam give BBC News Pidgin say di award no get anything to do with di United nations and e dey illegal. ""Dis na wetin I wan follow up wit di authorities in Nigeria, we get many organisations wey go just put United Nations for everything. ""Dis no get anything at all to do wit di United Nations. A number of civil society organisations around di world get way to participate for UN meetings of di Economic Social Council (ECOSOC) but e no mean say dem be members of di United Nations ""But dem fit participate and we dey give dem wetin we call 'consultative status', meaning dem get opportunity to participate ""We no dey sure if dem - United nations Rescue Services- get any consultative status wit di ECOSOC, but even if dem get e no make dem di United Nations. Di Award dey fake and e dey illegal,"" na so oga Ronald explain give BBC Pidgin. Oga Ronald also say no organisation get rights to give awards and name am under di United nations. ""We get protocols wey we dey follow to give di United Nations Awards or honours and dis no be am."" he add. BBC Pidgin follow di Global Chairman of di United Nations Rescue Service wey honour Tonto Dike wit di ""United Nations Noble International Ambassador"" Ambassador Steve Midalah explain give us say im organisation na one of di arms of di United Nations Economic and Social Council. ""Our goal na to work on di eradication of poverty for Nigeria and for us government no fit do everything alone, so we decide to come in and see wetin we fit do for our citizens ""We get initiative wey we dey call di United nations Noble Ambassador awards and we dey give dis award to only pipo wey identify themself to use dia knowledge, time and resources to serve humanity even though we no know dem before."" Oga Steve say na sake of dis dem decide to honor Tonto Dike for her humanitarian work. ""I neva meet Tonto Dike before, na just sake of di award but I dey follow her activities on social media, how she reach out to pipo especially during di lockdown. ""Na pipo like dat we dey identify to honour wit di Nobel International Ambassador Awards."" When we ask if dis award dey recognised by di UN, Steve say ""Na United nations recognised awards, I be one of di Executive Directors, I get di mandate of di UN."" Although di United Nations Information Department for Nigeria don refute dis claim. Dis no be di first time wey di Nigerian actress go dey involved in dis kain mata. Tori be say, earlier dis year di Nigerian actress bin lay claim to say she get appointment as di Nigeria Christian Pilgrim Commission Ambassador of Peace. Di commission later come out to deny say dem make Tonto Dike dia Ambassador. ""Dis claim by her dey spurious, unfounded and should be discarded and seen by all Nigerians as a figment of her imagination .""Na so NCPC tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56680379 +entertainment BBNaija S6: From Angel to Yerins - Liquorose, Saskay top BBNaija richest housemates list "Big Brother Naija reality TV show organizers don reveal a rich list of di 2021 housemates. Dis list show di amount of money wey each of di ""Shine Ya Eyes"" housemates don earn so far for di TV reality. Biggie put togeda di total money and reward wey di housemates dey earn through different tasks. Dis money and gifts dey different from di real star prize. From Angel to Yerins, dis na money for all di housemates to get some change wen dem return to di outside world. Di star prize of Big Brother Naija TV reality na ninety million naira (N90,000,000) for di one lucky housemate wey go win di show. Di BBNaija na Nigeria biggest TV reality show and most housemates wey contest dey turn celebs for di kontri. Sponsors of di reality show, they bring money, travel opportunities and plenty gifts for housemates wey go win di different task and competitions dem set. Any team or individual housemate wey win di task go get di reward. For di day 55 for di house, Big Brother show di amount housemates don make so far. Out of di 26 housemates wey feature for di reality show dis season, 15 don chop eviction. Di five dey up for possible eviction dis week wey include Cross, Sasky, Yousef, Angel and Emmanuel. Di eviction go come up on Sunday, 19th September, 2021." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58608024 +entertainment Tonto Dikeh: Prince Kpokpogri speak about reports say police arrest am "Nollywood actress Tonto Dike ex-lover, Prince Kpokpogri don dismiss report wey dey spread say police arrest am Monday, 18th October for Abuja, Nigeria capital. Local news media bin report on Monday say police arrest Kpokpogri on top attempt to cause a breach of peace for Transcorp Hilton Hotel, Maitama, Abuja. According to local media, e bin visit di hotel with two police guards to collect back one Lexus SUV wey Tonto Dikeh wey lodge dia bin park before police come arrest am. But Prince Kpokpogri wey follow BBC Pidgin tok for telephone afta two attempt to reach am, deny any arrest by police; ""Today na public holiday and dem say police arrest me yesterday but I dey my house today wey be public holiday, wetin dis one tell you? ""No be dis same tin dem bin tok di oda time wey dem say DSS arrest me wen I later come out to debunk am?"" Kpokpogri add say nobody arrest am anywhere and if pipo dey tok say dem arrest am, make dem tok di location wey e for happun and call out pipo wey witness di arrest. ""If police arrest me, I go fit tok to you? I no wan tok on dis mata for now until di outcome of police investigation. "" ""I no wan pre-empt di authorities and I no wan tok anything regarding wetin dey happun pending di outcome of di police investigation. I be publisher too, so I know most of dis tins."" Prince Kpokogri no gree reveal di nature of di investigation wey e say police dey do but e insist say im dey wait for di result of dat investigation before e go make any further comment. Meanwhile, di first time wey BBC Pidgin try to reach out to Kpokpogri during early hours of di day, di pesin wey pick di phone claim to be im brother and say e no fit confam if police arrest am or not. Also, local tori pipo Punch dey report say Deputy Inspector-General of Police, FCIID, Joseph Egbunike, order di arrest of Kpokpogri afta reports of one threatening situation for di hotel. Dem report say Prince Kpokpogiri wey bin dey face one investigation for Force CID bypass Police authorities, hire two police officers wey dey attached to Maitama Police station, den carry dem go Transcorp Hotel and threaten to open fire give Tonto Dikeh if she no hand over di keys of one SUV give am. But prince Kpokogri deny di arrest and dismiss all dis report. For July dis year, Tonto Dike bin officially confam say she dey in a relationship with Prince Kpokpogri. Dis bin confam di tori wey bin dey fly up and down about her relationship status den. Di Nollywood actor tag Prince Kpokpogri inside social media post wia she dey count her blessings and also refer to am as her 'husband'. Plenty pipo bin congratulate her and say dem happy for her. Prince Kpokpogri too bin also enta social media to unveil Tonto Dike and e say she dey blessed among women, im later delete di post." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58971880 +entertainment Nigerian Idol 2021: Kingdom beat Francis Atela to win Nigerian Idol TV show "Kingdom Kroseide na di 2021 winner of di Nigerian Idol TV show. Di Bayelsa born computer science and informatics student beat finalist Francis Atela to win di sixth edition of di show. As di winner, Kindgom go collect cash prize of N30 million (about $73,000), brand new SUV, 6 track EP recording deal (3 music videos) amongst oda prizes. Known for e soft spoken nature and strong vocals, Kingdom rise to become one of di most likeable contestant on di show na something wey many fans fall in love with. Dat fit be why dem vote am to win di show out of di oda contestants wey bin make di Top-11. During di early stages of di show, Kingdom tok about im passion for music. Dis passion show for di way wey im perform songs like Fela's Gentlemen, Majek Fashek's No more Sorrow and Timi Dakolo hit single Iyawo Mi amongst oda performances. During im victory speech, Kingdom wey bin dey emotional thank im Grandmother wey bin 'prophecy' say ""im go be great""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57799120 +entertainment Cameroon music association go meet for helep musicians wey deh di sick "Condition for some Cameroonian musicians di worri as deh di sick and no even get moni to go hospital. Na video for popular musician for August 15, Nguea Laroute for social media, make pipo wanda how big musicians weh deh don make kontri shine for high level fit sick laik dis no get moni for go hospital. Ma Nguea say e don sick for many years and de moni weh e bin get finish for merecin, deh even wan operate ask FCFA 10 million and e no get. So for video e di beg Ma Chantal, President Biya e woman and oda pipo weh get sorry heart for helep e go for treatment. Mama Nguea no bi de only musician weh e dey for bad condition, Henri Njoh, Marthe Zambo and mani odas too need help. San Fan Thomas, president for Cameroon music artist association, SONACAM, tell BBC Pidgin say for Monday, musicians go shiddon for meeting check how deh fit helep dia colleague. For yi any man fit sick and musician e situation no suppose bi different. But anoda popular musician, Romeo Dika say condition for Cameroonian musicians na result for weti weh de put dem selves inside, quarrel wit odas and no di care for general interest. ""Cameroonian artist create dia own problems, enta war weh e no di make dem progress"". Musicians weh deh don put de kontri up, bi laik pipo weh deh no anytin for kontri but weh 50 years afta musician die, e music rights continue for enta for public space for goment Dika tok. So goment get for take care for famous musicians for dia life taim. Bidoung Mpkwatt, Minister for Culture don send pipo for check de condition for Mama Nguea and sick musicians for see how deh fit take care for dem wit dia small moni. But Dika check e own say musicians fit push goment for make law for change position for musician, for dia social security, deh fit place dem laik workers. Also, if musicians wan make dia condition change deh get for check weti bi more important for dia life and professional progress. Make musicians look weti fit bi general interest, share dem, instead for look only for personal interest and small rights moni weh e no fit do anything Dika insist. Cameroon musicians get plenti problems wit dia rights as goment di sometiam poke nose for musicians dis association. Some musicians even komot go shiddon for Prime Minister e office last year for fain solution for dia rights moni weh deh no pay." https://www.bbc.com/pidgin/49388922 +entertainment Why friends and fans of Kanye West dey cancel am "Kanye West. wey change im name to Ye, don do plenti tinz ova di last few years wey dem make am seem like na im face you go see for dictionary if you type controversy. At some point di tok-tok on top di way im dey act loud sotay, e release one song ""I miss di old Kanye"". But e be like many of im fans don give up say di old Kanye go ever come back. Dis na on top say wetin di rapper and fashion businessman, Ye don do for October don pass be careful. From ""White Lives Matter"" shirts, to wetin im tok about Jewish pipo wey make dem lok im social media to even im tok about George Floyd. Opinions on wetin dey do am don cause division with im fan base.Dem dey wonder weda na im mental health cause am, or im just wan vex pipo on purpose. Ye get bipolar disorder but some pipo say mental health issues no dey make pipo dey anti-sematic. Howeva dis no go be di first time over di years wey im dey controversial, most popularly wen e wear di MAGA hat to see Trump and di MTV VMAs mata with Taylor Swift. During di Paris Fashion Week, Ye raise eyebrows wen im showcase t-shirts wey im write ""White Lives Matter"" on am. Di mata loud and even one Vogue editor Gabriella Karefa-Johnson call am ""hugely irresponsible"". White supremacist bin start to dey use am for 2015 to respond to di black lives mata movement. Fellow rapper Diddy bin text Ye on top im post but di rapper say na Jewish pipo dey control am on top am come post dia entire conversation on top social media. Diddy later comot for im own social media page to tell pipo make dem no wear di shirt or buy am. As pipo say im dey drag di Black Lines Matter movement, im call di organisation say e be scam. All dis make am so even wen e make Instagram post say im dey plan use di money from those shirts give di black community pipo still no pay attention to am. Speaking of social media posts, Ye make dem lock im social media for dis same mata of White Lives Matter as well as some of di tins wey im tok about Jewish pipo. For Instagram na wen e post di message wia im tell di Diddy say, ""I go use you as example show Jewish pipo wey tell you to call me say no one fit threaten or influence me"". Afta dem block am for Instagram, e enta Twitter to hala for Jewish pipo say ""sleep dey my eye tonight but wen I wake up, I dey go death con 3 on Jewish pipo."" E add for di tweet say e no fit dey anti sematic sake of say black pipo be Jews too. Dem comot di tweet and lock Ye account. For interview wey im for Drink Champs podcast, e tok about how Adidas dey review im contract. E also blame di Jewish community say because of wetin im tweet, di pesin wey follow am create di ""White Lives Matter"" t-shirt no wan mass produce am again. For di same interview im make mention of comedian wey bin dey date im ex wife Pete Davidson wey im call ""heroine addict"". Di most recent interview with Piers Morgan, di only tin Kanye West bin talk sorry in relation wit wetin im tok about Jewish pipo na say ""I go say sorry to all di pipo wey I hurt, all di families wey no get anytin to do with di death con wey dey affect... hurt pipo, hurt pipo"". Dis mata don dey affect im business interests as Adidas say dem dey review dia partnership, e don nd im collabo with di Gap and JP Morgan say make im carry business go somewia else. For di Drink Champs podcast, Ye bin also call out di George Floyd incident. E say ""I watch di Candance Owens documentary about George Floyd and dem no even kneel down for im neck like dat, dem hit am wit Fentanyl"". George Floyd bin die for May 2020 afta police bin put leg for im neck for a long time on top fake $20 bill. Wen di video of di arrest wey kill am go viral, im death ginger di emergence of Black Lives Matter protests around di US. Now, George Floyd family dey decide weda to sama Ye with $250m lawsuit for defamation for wetin im tok during di podcast." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn0xk07w54go +entertainment BBNaija Saturday night party: DJ Xclusive totori housemates plus all di drama wey happun for Saturday night party Beach wears and plenty serenre bin happun for Big Brother Naija season six Saturday night party as housemates dance to jams for Biggie house. Ogbonge DJ Xclusive host di housemates for di party wey go down on Saturday night. Dis na some of di main highlights of Biggie beach party. Di housemates come all prepared and dazzle inside dia beach outfits for the party. Dem understand di assignment and smash it with di outfits Biggie provide for dem. Na so di organisers describe di eye-catching outfits wey di housemates bin rock for di party. Di housemates prepare wella for di beach themed party. Di guys wears nice shorts and beach shirts while di women wear beach dresses and flower accessories for dia hair. Dem complete dia looks wit sunglasses. Di housemates ginger well-well wen dem see Xclusive as di DJ for di night and him no disappoint dem. E totori dem wit popular Naija songs. Dem dance all night as him give dem back to back gbedu for di party. Saga keep Nini to himself all night, di two couple dance wit each oda well-well for di party. While Angel and Sammie wey dia relationship get as e be for some days now sake of di quarrel wey dem get afta di truth and dare game - dem enjoy each oda company again for dance floor wit dia sexy dance moves. Meanwhile for Liquorose and Emmanuel, di couple bin dey feel each oda company well-well for di party. Dia facial expression, dance moves and close eye contact for di dance floor show how dia relationship don grow since di show start. Some fans bin dey tink say di couple go share dia first kiss on camera based on di kind vibes dem bin dey give for di party but dat no happun. And, one of di new female housemate JMK surprise everybody wit her ogbonge dance moves. Boma and queen bin get small argument afta di party end about dia relationship, e no really clear wetin cause di argument but Boma clear her say make she stop to dey act like say two of dem get something. E tell her say him no dey inside any relationship with her. As di two of dem dey go back and forth ontop di matter, Emmanuel enta di room and carry Boma comot so Queen wey already bin dey a bit tipsy fit sleep. No be only dia drama happun JackieB tackle Michael too about dia relationship. She say she bin feel one kind wen Angel rub Michael hair in front of oda housemates. She tell Michael about di issue but im try to defend himself. For now fans go get to watch and see if dia ship go still sail or sink. Dis week, six housemates dey up for possible eviction. Dem be Arin, Emmanuel, Nini, Princess, Sasky and Tega. Voting don end already and on Sunday, at least one of dem go leave di Big Brother house while di remaining go stay to compete for di N90 million naira worth of grand prizes. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58220408 +entertainment Burna Boy vs Shatta Wale: Burna boy apologize to everyone afta e reply Shatta Wale "Nigeria Grammy award-winning musician, Burna boy don apologize to evribodi wey feel say e lower e standard as ""African giant"". Burna Boy issue dis apology afta e bin reply Ghanaian dancehall artist, Shatta Wale wey insult and drag Nigerian musicians for social media last week. Burna wey dey refer to imsef as di African giant tok for di apology wey e post for instagram say dis na di last time wey e go allow imsef to stoop to dis level. ""I dey sorry to evrione. I no dey do dis type of thing....But I promise dis na di last time I go ever allow mysef to stoop to dis level."" Burna Boy also tok say e no go dey social media thru out dis year. ""See you all for real life,"" na so Burna post. Last week, Ghanaian dancehall artist, Shatta Wale bin call out Nigerian artists during di Freedom Concert wey e organize with Medikal on 25 December. ""Dem tell me say I no go dey able to fill my stadium. Ghana make I tell una something, me I no dey look up to any stupid Nigeria artiste oh!"" ""Me I dey look up to you pipo, na una be my Nigeria, na una be my America, na una be my abroad pipo,"" na so Shatta Wale tok for stage during di concert. Di singer later come conclude di speech wit one swear word on wey immediately make some Nigerians begin drag am for social media. Even wit di dragging, Shatta Wale no stop dia. E allege for series of tweets say dem no dey promote Ghana artist like dat for Nigeria. Burna Boy later come respond say Shatta Wale claim na ""something fishy"" and ask if dem dey play South Africa, American and UK music for Ghana. ""Dem dem dey play South Africa, American and UK music also for Ghana? But na Nigeria own be issue. Something fishy dey smell,""na wetin Burna on 31 December. ""To dey push dis agenda of separation between our beautiful African Nations na serious disservice to generations wey dey come afta us. And e go against evritin I stand for as a man and as pesin wey be unapologetic pan Africanist."" ""Nobodi go spoil di unity we don dey try to build for a stronger and beta Africa."" Shatta Wale, also come respond and dare Burna Boy to do freestyle battle for Accra sports stadium. But Burna clear di air say im no mean 'rap battle' but 'fist battle' and later say sorry for wetin im tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59850896 +entertainment Daft Punk don break up afta 28 years French electronic music duo Daft Punk wey be popular robot like two don break up afta 28 years to geda. Dem announce di break-up for one video wey dem post online, wey dem tell demselves bye-bye before one of dem come scata. Di band longtime publicist na im confam di tori give BBC. Di French band bin come togeda for 1993 and dem dey popular for fact say dem no dey show dia face as dem dey wear robot helment on top and even use computer to make di voice to sound like robots for dia songs. Dem tok say di reason na on top day dem no be models so im no go totori pipo to dey see dia face but say di robot lok de sweet pipo for belle. Speaking of music, di band dey very popular for dia gbedu Get Lucky wey dem with Pharrell Williams and Nile Rodgers as well as, Starboy and I Feel It Coming wey dem follow The Weeknd do. Dem also release Harder, Better, Faster, Stronger wey Kanye West cari to make im own hit Stronger. Dem bin also win Album of di year Grammy for 2014 for dia album, Random Access Memories. https://www.bbc.com/pidgin/world-56162091 +entertainment Wizkid three albums wey give am mouth as 'Afrobeat giant' Wizkid, Ayodeji Balogun, don create beta name for imself and African music from di time wey im release im first hit single for 2009. Even as at now, wey pipo dey wonder wen 'Made in Lagos' im new album go comot afta di last one 'Sounds from the other side', im fan base still dey im back gidigba. As dat one still dey come, e release EP for December 2019, wey im call Soundman Vol. 1 to make im fans cool temper. However, on 16 July wey be im birthday, pipo don ginger again on top di album wey im don promise im fans since 2018. But as dat one dey happun, we say make we take una back to im three albums wey im don do since im begin im career. Dis album drop for 2011 and e feature gbedu like Holla At Your Boy, Love My Baby and Pakurumo. Before den im don dey enjoy plenti airplay with im songs like Tease Me and Don't Dull. Na di same year wey im win di award for di Next Rated for di Headies, MOBO wia im win Best African Act and also collect nomination for di MTV Europe Music Awards. And for 2012, e win di BET International Act Africa. Im drop Ayo for 2014 afta im don establish imself well-well for di industry. Na for dis album, im release in popular banger, Ojuelegba and di 19 track album bin flow from reggae tunes like Joy, to gbedu wey im release with Femi Kuti, 'Jaiye-Jaiye' to even love songs like 'In Love' wey im sing with Seyi Shay. E carry di album win di Headies for Best R&B/Pop Album for 2015 and Song of di Year for Ojuelegba. Dis na one of im most popular albums wey blow scata for obodo oyibo on top say e feature international musicians dem ontop im afro music. Artistes like Drake for Come Closer, Chris Brown for African Bad Gyal and Trey Songz for Gbese na im feature. Dis album na also di first album wey im release afta im comot from di EME record label wey Banky W bin dey run. Around dat time, for 2017, Wizkid get im first Award for Grammy as Drake win Album of di Year for im album 'Views'. Wizkid bin get writing credits for di album for im work for inside di hit song, One Dance. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53414606 +entertainment Lateef Adedimeji: Nollywood actor wedding wit Adebimpe Oyebade Nigerian Actor Lateef Adedimeji today wed im colleague for di movie industry actress Adebimpe Oyebade. Di wedding wey dey happun for Ikole Ekiti, Ekiti state witness plenti pipo plus popular actors and actresses for di movie industry. Last month di popular actor bin confam to BBC Yoruba afta fotos of dia wedding invitation card begin circulate for social media say dia wedding don set. Di confirmation be di first time Adedimeji go publicly confam im love affair wit Adebimpe Oyebade, afta di two Yoruba Nollywood actors don deny several times say nothing dey between dem, say dem just be friends and colleagues. But on Saturday 18 December 2021, di two actors tie di knot of dia relationship. Lateef Adedimeji na young Nollywood actor, screen writer and producer. Dem born am for February 1 1986 for Lagos state but e come from Ogun state. Lateef get degree from Olabisi Onabanjo University. E begin dey act professionally for 2007 and don act plenty feems both English and Yoruba feems. E also don win pleny awards. Oyebade Adebimpe wey many pipo sabi as Mo Bimpe na Nigerian actress. Dem born her March 23, 1997. She be native of Ijero for Ekiti state, South West Nigeria. She start her acting career for 2016 and don feature for plenty Yoruba feems. https://www.bbc.com/pidgin/media-59712969 +entertainment Ada Jesus: Mmesoma Mercy bin want go live to thank pipo wey dey pray for her- Harrison Gwamnishu "Harrison Gwamnishu wey dey lead di team of pipo wey dey take care of Ada Jesus before her death don tok about di popular Nigerian Comedian last moments before death. Di comedian bin reveal say she get kidney disease in February, and tori be say dem rush her to hospital after suffering a cardiac arrest - wey lead to her death. For interview wit BBC Pidgin on Thursday, a day after di announcement of her passing, Harrison narrate Ada Jesus Last moment before she die. He tok say Ada Jesus bin ask for phone, say she wan go live on social media to thank di pipo wey dey support and pray for her, but before dem bring phone for her, she don die. ""On Tuesday (20 April, 2020), we dey wit Ada Jesus till about 5 to 6pm, wen we dey go she no wan make we leave her comot , she cry say make we no leave. Around 11pm na im di husband, Kinsley call us for phone say dem wan give her injection. because dem dey give her drugs and injection every evening"" Oga Harrison add say ""E tell us di injection na 50,000 naira make I send money come, but I never send dem money direct like dat before. We deposit directly to di hospital account to treat di girl. But when he tok am, I come send am di money about 11pm for night. After 10 minutes. Kingsley call me say im no know wetin dey happun again o, say Ada no fit tok again Say she dey breathe faster, say doctors and nurses full for di ward. I leave wia I dey , come rush down go di hospital. True-true I see doctors dey press her chest and put oxygen for her face, Na later dem carry am go ICU Around 7-8am in di morning, Doctor come tell us say she don die."" He add say Ada bin don dey improve, she don dey eat, she don dey tok and do other things on her own ""E shock us say she just die laidat. Even wen we carry her go mortuary, we no sabi how we go tell her family. Ada Jesus last moments For her last moment, Ada experience love from pipo, from pipo wey she no even know before. She dey always make us laugh, even wen I come to di hospital wit heavy hearts, she dey make us forget say dey sick."" he tok. ""Anytime we are around her, we dey show her videos and comments from pipo wey dey pray for her, dey support her, She later ask make we give her phone say she wan do live to hail di pipo wey dey support and pray for her."" Harrison reveal. Di death of di comedian come as a shock to many Nigerians wey don enta social media to express dia grief. 24-year-old Ada Jesus, bin dey known for her skits on social media, mostly in Igbo language - although she bin dey also perform as a stand-up comedian." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56850094 +entertainment Mjokes Matsane: Interesting facts about South African musician Mjokes wey die for car accident Di entertainment industry still dey mourn di death of South African music star Emmanuel “Mjokes” Matsane, member of di music group Trompies, wey die in a car accident on Sunday morning. Him record company Kalawa Jazmee confam say Mjokes bin perform alongside di group on Saturday night before di motor accident. Many pipo don enta social media to express dia grief ontop di sudden death of di music legend. Speaking to tori pipo for eNCA, fellow musician Speedy say im colleague and friend na di life of di party, and dat im remain shocked at im sudden death. Speedy reveal say im bin see Mjokes one week before di tragic death “I see am last week, at our weekly meeting wit di label. “He be funny guy, wetin pipo no know be say, many pipo no know say wen we bin start di group back in 1996, na Mjokes dey write all of my parts. “I will definitely miss him, he dey always bring a great energy to di band.“ Before im death, Mjokes play a huge role to shape di kwaito music industry. Trompies begin make music for 1990 and release dia debut album Sigiya Ngengoma in 1995. Mjokes lead di Trompies’ popular song, Sweety Lavo. Mjokes, was na di lead singer for such hits as Magasman, Fohloza, Zodwa, Bengimngaka, Current and Malabulabu. Matsane also get successful solo career, as im dey use di name Copperhead. One of im singles, Umtwanakhe, bring am to limelight success. One of e band members, Speedy reveal say Matsane get di name Mjokes because he dey always crack jokes and he dey always make dem laugh. He say Mjokes bin recently build im new house before the tragic accident take im life. According to im record label, Mjokes also recently release one new single, 'Phansengendlondlo', on di 14 May 2021. Im survived by wife and children. Kalawa Jazmee confam dem born Emmanuel “Mjokes” Matsane in 1966. Later in di week, dem go announce burial plans for di music legend. https://www.bbc.com/pidgin/world-57225997 +entertainment Odunlade Adekola: Yoruba actor react to accuse say im dey ask female actress sex for roles in movies "Ogbonge Nigerian actor Odunlade Adekola don challenge any female actress wey im don ever ask for sex before e give am role for movie to come out wit receipts. Odunlade wey dey very popular wit Yoruba movies bin dey react to one blog report - Gistlovers, wey accuse di actor of sleeping wit girls before e give dem roles for films. Dem mention names of some girls wey don allegedly fall as victim and one small girl wey im dey allegedly do di same thing to at di moment. However, Odunlade inside video for im verified Instagram handle don come out to debunk di accuse. E dare any actress wey don pass through im film school or wey still dey work wit am to come out wit evidence. ""I put am to all of dem, all di ladies wey don pass through me and di one wey dey wit me now, from Taiwo Aromokun to Eniola Ajao, Tosin, Nike Hamzat, Bukky Adeeyo, whether di pesin fat or thin, if I don ever ask you for sex before I give you any role, come out and say it, if you cover me, God no go cover you."" Odunlade tok. Di actor tell di blog and everybody wey dey plan to bring am down to come out wit prove say im dey request sex for roles if not, God anger go visit dem. Oga Odunlade wey claim say im don dey work for di movie industry for di past 25 years say di reason why im come out to clear di mata na because of di young pipo especially young girls get interest for di industry and wey dey see am as role model. E also say im be disciplinarian wey no dey tolerate nonsense. Dis no be di first time di actor go dey alleged to get relationship wit some of di female actress wey dey work wit am but everything na still rumour wit no official confirmation. Many pipo for Nigeria sabi di popular actor sake of im memes and comedy wey im dey act sometimes. Odunlade Adekola na Nigerian actor, singer, film-maker, producer, director and influencer. Dem born am for December 31, 1976 and e come from Ekiti state, South West Nigeria, although e grow up for Abeokuta, Ogun state. E don act for plenty films and e even get im own film production company. Di actor attend im Primary and Secondary School for Abeokuta, then Moshood Abiola Polytechnic and di University of Lagos for im tertiary education. Odunlade begin im acting career for 1996, di same year e join di association of Nigeria Theatre Arts practitioners." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58511999 +entertainment Tiwa Savage video: Five oda celebs wey dia sex tapes comot "For days now, plenty tok don dey about Nigerian singer Tiwa Savage and one alleged sex tape video of her. Na last week, di ""Somebody's son"" singer reveal say pesin bin dey blackmail am for one clip wey she bin do with her bobo. Last week, Tiwa Savage bin tok for one interview for The Angie Martinez show - for New York Power 105.1 fm say e get some pipo wey dey try blackmail her over one allege sex tape and she don decide to call dia bluff as she no go pay dem shishi. Dis conversation don see Nigerians and fans of di singer ask why celebs like to dey record sex tapes. Dis question come about as some don also point out di oda times wey sex tapes of dia favourite celebs don go viral. Over di last few years, celebs don enta di kwanta of leaked naked pictures or video of dem wey comot or bin dey leaked for social media. Dis na di oda times wey such leaks and threats of blackmail to leak dia nudes don happun to celebs for Ghana and Nigeria. For April 2020, Nigerian waka singer,  Salawa Abeni bin burst pipo head afta she say pesin bin dey blackmail am say dem go post her naked pictures if she no give them money. For di Instagram post she reveal say she bin either dey for hospital or with her partner when dem take di pictures but tok say she no go let anyone bully her as she post di pictures herself. Later police come arrest di alleged blackmailer wey bin dey di age of 19. For 2017, video comot of di Mosquito Killer singer dey masturbate for inside Snapchat. Tori pipo tok say im later comot to reveal say na hack dem hack im phone post am. One of di most controversial Big Brother Naija reality TV show housemates, Tacha bin receive blackmail for 2020 for nude pictures wey she say bin dey edited. She come on Twitter to post di email wey she bin get. For April 2020, media personality Toke Makinwa bin face blackmail too by pipo wey tok say dem go post her nudes except she pay dem. For Instagram post wey she later comot, she post di picture and tok say di one wey dem bin dey blackmail her with dey photo shopped. For 2018, video bin comot for di Dancehall artiste snapchat wey apparently show one woman dey give am blowjob. E later post video on top im same snapchat wia e confam di video wen e ask weda dem neva see pesin dey collect head before. Howeva im no confam weda di pesin wey dey di video na him." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58929073 +entertainment Police describe trending social media video of 'Davido son' as fake Di video of one pikin wey drown for one children swimming pool no be di son of Nigerian music star Davido, authorities tok. Di video wey dey circulate on social media don go viral wit many misrepresenting di victim to be Ifeanyi Adeleke wey police dey torchlight im death. Police tok-tok pesin for Lagos describe di video as “fake”. “We neva eveb begin look di content of di CCTV wey we collect from Davido house. “Any video you see online no be di real tin. Na fake,” Benjamin Hundeyin tell BBC Pidgin. Also, checks by di BBC Disinformation Unit say di video no be from Nigeria. Di Unit discover say di CCTV footage wey dey go viral for Nigeria na dat of a two-year-old boy for China. Checks reveal say di viral video wey show pikin wey dey drown inside children swimming pool happun for China on 23 August, 2019. Di tori of pikin wey drown inside pool bin trend dat time. Davido and im fiancée Chioma Rowland, a popular chef and influencer, neva tok about dia pikin death. On Tuesday police invite eight domestic staff of di celebrity for questioning. Di nanny wey dem employ to take care of Ifeanyi Adeleke still dey wit di police. Di Lagos state police command confam to BBC Pidgin say dem retain di nanny aas dia investigation kontinu into di death of di 3 year old son of Nigeria music star, Davido. Tori comot on Monday night say Ifenayi Adeleke don die -  tori be say e drown for swimming pool for im papa house for Banana Island. On Tuesday police arrest eight pipo, all of which na di domestic staff wey di house wen di incident happun. “We arrest dem for questioning make dem tok wetin dem know about di incident. Afta di interrogation we go release anybody wey we no feel say na suspect,” Benjamin Hundeyin, Lagos police tok-tok pesin tok. E say di police go den arrest anybody wey dem no dey comfortable wit im response. As pipo still worry about di incident wey attract global attention, police don confam di release of six out of di suspects wey dem bin arrest – dem retain two. Hundeyin say di two pipo dem retain na sake of investigation wey still dey go on for di mata. E say di two na di nanny and “one oda pesin wey I no know,” but na to ask dem questions before “we know wetin we dey do next.” Di police say di six pipo no pass di night for station – dem get dia bail on di same day. Di police explain say dia standard procedure wen dem dey investigate mata wey concern pesin death na to conduct autopsy. Benjamin Hundeyin say as far as di death of Ifeanyi dey concerned dem go also conduct autopsy. “E get some families wey dey tok say dem no dey interested in autopsy even though na something wey we suppose do. “On dis case, Ifeanyi parents, dat na Davido and Chioma neva tok say dem no dey interested,” e add. E say as tins be now police go conduct autopsy excep dem hear from d parents. Police say di swimming pool wey di incident happun no be active crime scene “so no need to close am”. Oga Hundeyin say even though di police dey torchlight di mata di swimming pool still fit still dey open to use. Di parent of di boy never comot to comment on di incident. Ifeanyi na di son wey im get wit im Fiance, Chioma Rowland. Di death of dia pikin happun days afta di family celebrate di pikin third birthday wey shelle for October 20. Some days before, e bin get one video wia  Davido dey teach Ifeanyi  how to swim. For di videos wey bin trend for social media Davido bin carry di pikin make am flap im legs for di water as e dey tell am wetin to do. Dis go be di second time wey celebrity for Nigeria go loose pikin to drowning. For 2018, D’banj and im wife, Lineo Didi, lost dia first pikin afta e bin drown for pool. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cy6q2q8dp16o +entertainment Groovy, Sheggz and Hermes dey evicted from Big Brother Naija show "Di latest housemates to comot di Big Brother Naija reality show na Groovy, Sheggz and Hermes. Di three male housemates chop eviction from di Level Up house on Sunday ending dia chance to compete for di 100M naira prize. Dis mean say five housemates wey be di finalists plus two riders remain as di season 7 of di African biggest reality show dey close. Chichi wey earlier for di week win di head of house game bin get immunity against eviction nomination and also get ogbonge power to save two housemates. Head of House Chichi bin use her power to save Pyna and Daniella wey den leave every oda house for di eviction table. Di show wey dey popular among Nigerians youths dey always attract criticsim from some pipo who believe say di reality show dey promote reality. Over di years, many Nigerians don criticise di show and many continue to see di show as ""distraction"" and something wey no dey add value to di society. In 2019, one Islamic human rights organisation, di Muslim Rights Concern, Muric bin ask di Federal goment of Nigeria to ban di show. Na 28 housemates start di Season 7 Level Up Big brother Naija show , wey begin on di 23rd and 24th of July, 2022. Na 8 weeks housemates don spend for di house and di remaining housemates dey enta di 9th and final week. From di 28 housemates wey enta di Level Up house, Beauty chop disqulification few weeks afta di show start. Di housemates wey don comot so far by eviction na Christy  O, Cyph, Khalid, Ilebaye, Kess, Pharmsavi, Amaka, Diana, Giddyfia, Doyin, Chomzy, Allysn, Dotun plus Modella-fake and Deji wey be fake housemate. Past winners of di shows include, Katung Aduwak, Efe Ejeba, Miracle Igbokwe, Mercy Eke, Olamilekan Agbeleshe, Hazel Oyeze Onou. Di race to win 100M naira grand prize go end dis week and dem go unveil di pesin wey win ontop live broadcast next Sunday, 2 October." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cx80v9qdjx9o +entertainment Queen Elizabeth dey celebrate 70th anniversary of her reign "Di Queen of England don comot to cut cake for di celebration of her Platinum Jubilee wen she meet with members of di Sandringham community a day before di 70th anniversary of her reign as Queen of England. Ahead of wetin dem dey call Accession Day, she play host to volunteer groups wey include pensioners and members of di local Women Institute (WI) group. Di Queen don be member of di Sandringham branch of di WI since 1943 and don be dia presido since 2003. On Sunday, she go don reign for 70 year except from di Accession Day. Di day go also mark di death of her papa, George VI for 1952. Dis event for di Sandringham House na di largest in person public event wey di Queen don attend since October wen she attend reception for Windsor Castle. Recently, pipo don dey fear for her health afta she spend di night for hospital and royal doctors order her to rest last autumn. But Vice-president of di Sandringham WI Yvonne Browne, say di Queen bin dey ""sparkling"" form on Saturday as she follow pipo dey laugh and joke for di event. Royal Correspondent Sean Coughlan say di reception for di Queen Accession dey normally dey lowkey on top say na also anniversary of di death of her papa. Queen Elizabeth go be di first British monarch for history wey go celebrate her Platinum Jubilee. Sunday go mark di start of di jollification for her jubilee and e go end with four day bank holiday weekend from di 2nd to di 5th of June. During dis period, dem go hold concerts, street parties and Platinum Jubilee Pageant and open up di private estates for Sandringham and Balmoral for di long June weekend." https://www.bbc.com/pidgin/world-60273970 +entertainment Tiwa Savage video: How celebrities react to di musician sex tape "Di tok of one so called sex video of popular singer Tiwa Savage don become di number one trend for Nigerian social media space. As hundreds of thousands of pipo dey search di video online, some dey chook mouth to discuss am di mata. Di singer and songwriter bin earlier reveal say pesin dey try blackmail her wit her short sex clip. She share dis tori for one radio show - The Angie Martinez show - for New York Power 105.1 fm on 8 October. ""I no go call am sextape, but na video of me wit di pesin wey I dey see (date) right now"", na so she tok Tiwa say dem share di video wit her wey show her wit di bobo wey she dey currently date and she say di pesin wey get di video come dey blackmail her and dey ask for money. Reports bin say di alleged video later surface for social media wey make many of her fans dey tok. E no dey clear if na Tiwa Savage dey di video, dat na wetin some Nigerians dey tok. Odas wey believe say na she dey di video don criticise di move. Nigerian celebrities don also chook mouth for di conversation. Popular media personality, Daddy Freeze say dis na opportunity for fans to show her love. ""Wetin she do na wetin everybody dey do, wetin just different na say she carry camera go dia."" E say dis 'sex video' go objectify women and dis no go do women any good E say dis na time for oda women to stand wit each oda and stop to dey laugh ""Dis na your role model, your fave or whatever you dey call her, she dey in need right now , She no need your money or any other tin, she need your love."" Nollywood actress, Susan Peters also chook mouth. For her Instagram page, Susan Peters ask why pesin go do video of woman alone no put im face. ""Why you go even do video in di first place?"", she ask. Anytin you do, you go reap...our sympathy don go off di roof, she add. Actress, Mercy Aigbe tok for Instagram post say, Nobody holy pass. ""Any man wey love you no go record you during intimate moments,"" na so Actress Georgina Onuoha tok for one video she post. She advise women make dem no trust any man no matter how di relationship dey shark dem. ""No lose senses, no trust pipo even your husband"", Georgina add am even as she say nothing wrong to fall in love. Former reality TV star, Angel Smith also comment to criticise di pesin wey decide to leak di sex tape. ""Di problem no be di fact say pesin make a sex tape or say pesin take a picture naked. Di problem go always lie wit di pesin wey decide to leak am."" she tok. Actor and reality TV star, Tochi also ask pipo to stop dey post Tiwa Savage picture at dis time. ""Please stop all dis posting let her heal, before her son starts asking her why people are posting her and tagging her a queen"". Wetin Tiwa Savage tok about di video? For inside post wey she put for social media, Tiwa savage bin tell di pipo wey dey behind di sex video say dem hate her sake of say she take di mata wey dem wan take destroy am joke for stage. Tiwa savage say she don dey able to control di gbege since she don come out to tok about am. Tiwa bin write for di post say: ""You hate how I dey able to control di narrative and get ahead of one story before e consume me and how I dey able to joke on stage about sometin you bin think say suppose destroy me and make me feel ashamed."" ""You must knock my head wen you see me odawise…,"" she post. Di Nigerian Afropop queen, bin also tok on stage during one show for Lagos say ""nobody go ever see di sex tape""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58970575 +entertainment 2021 Year end: Rachel Oniga, Sound Sultan, Ada Jesus, Victor Uwaifo, celebs wey die 2021 "Year 2021 na very tough year for many pipo around di world and Nigeria no dey exempted sake of Covid plus many oda disturbing tins wey happun. Many things happun for di year and part of dem be say Nigerians lose a lot of dia celebrities. BBC Pidgin present popular celebrities wey die for di year 2021. Nigeria bin lose one Nollywood star Folake Aremu alias Orisabunmi wey die on January 5. Orisabunmi wey come from Kwara State bin dey popular for di priestess role she dey play for movies. Veteran Nollywood actor Ernest Asuzu bin die on January 26 at di age of 37 after im slump. Asuzu wey also be musician dey popular for playing criminal and hitman role for movies. Di actor bin enta limelight afta im act for one Nollywood blockbuster movie Another Campus Queen in di 90s. Veteran Nigerian actor and broadcaster Sadiq Daba die on di evening of Wednesday, March 3, at di age of 69. Di ogbonge actor bin battle leukaemia before im death. Daba bin work for Nigeria Television Authority (Nta) and also play di role of Bitrus for soap opera Cock Crow at Dawn. Popular Nigerian comedian Ada Jesus wey her real name be Mmesoma Mercy Obi die on April 21 afta she battle wit kidney problem. For one interview wit BBC Igbo, Ada Jesus bin tok say she dey sick wit kidney problem. For interview wey she do for February 2021, di Instagram sensation bin say e don reach almost one year wey she don dey battle di illness. One of di members of Davido crew Habeeb Uthman aka Obama DMW die on Tuesday, June 29. Obama DMW death pain many of im celebrity friends wey describe di man as ""real pesin"". Dem born Obama DMW for Lagos and im get im Bachelor's for Lagos State University before im port go Canada. For DMW, e bin follow work as Davido road manager before im form im own record label inside DMW wey im call Obama Music Worldwide. Sound Sultan na ogbonge musician wey die of throat cancer on Saturday, July 11, im family bin announce. Di singer wey im real name be Olanrewaju Ganiu Fasasi die at di age of 44 and dey buried for Muslim cemetery, New Jersey, United States. Sound Sultan name no fit dey omitted wen pipo dey mention artistes wey start modern hip hop music for Nigeria. Nigerian veteran actress Rachel Oniga bin die at di age of 64 on July 30 from heart-related issue. For statement wey her family release, dem announce say Oniga die for one Lagos hospital. Di actress come from Delta State and dem born am on May 23, 1957. She begin her acting career for 1993. Oniga family describe her death as ""God design"" and ""function of a race of life well finished"". Nigerian bin lose dis Ogbonge actor on August 26 at di age 69 years. Before im death, di actor bin dey battle for im life after di accident wey im get for 2016 as im dey drive go set for Lagos, Nigeria. Olaotan bin act as di main character named Fred Ade-Williams for popular Africa Magic TV series Tinsel. Di ogbonge musician die on August 28 at di age of 80. Sir Uwaifo na legend wey many pipo respect well before im death, and im song Joromi na evergreen. Im release di song for 1965 wen im dey 24 years and di veteran musician don sing many oda songs wey be hit. Popular Nigerian comedian Babatunde Omidina aka Baba Suwe die at di age of 63 on November 22. Na im son Sola Omidina announce di death of di veteran actor on im Instagram page and also confirm to BBC Pidgin. Baba Suwe begin acting for 1971 but become popular afta e feature for one movie titled, Omolasan. Im become more popular afta e feature for Iru Esin, wey Olaiya Igwe produce for 1997. Veteran actor Sam Obiago aka Daddy Sam die on Thursday, December 23. Na di president of di Actors Guild of Nigeria, Emeka Rollas, confirm di news of di actor death on Thursday. Daddy Sam feature for Nollywood movies like; Tears of a King, Royal Appointment, Blood Brothers and oda popular films. Di veteran Nollywood actor bin die on Saturday, April 10, after im battle with diabetes. Bruno Iwuoha die at di age of 68 and many Nollywood filmmakers describe im death as shocking. Nollywood actor, Karibi Fubara die on Wednesday 15 December, 2021 . Im family members announce am on top dia social media page. Di ""God calling"" actor bin dey diagnosed wit cancer for 2020. For one of im Instagram post afta di surgery, e say na around Easter e bin receive di news say im get large mid-stage kidney tumor/cancer. And on 3rd May, 2021 I had a very successful surgery remove about 90% of the tumor." https://www.bbc.com/pidgin/59802120 +entertainment Headies 2019: All di tins wey Nigerians tok say no gel, full winners list Dis year, di Headies 2019 awards honour some of Nigeria ogbonge musicians like Burna Boy, Teni, Falz, Chinko Ekun and many more. Di Headies na one of di ogbonge awards wey dem torchlight Nigerian performers and plenti pipo dey always look forward to am every year. Correct gist dey always follow di event and di 2019 edition no dey different at all, as pipo don go social media to tok some of di tins wey dem feel no work for dem as dem dey watch di award. Dis year edition happun for Lagos, Nigeria with Reminisce and Nancy Isime as di hosts of di event. However, many of di pipo wey watch di event from dia house tok say di two of dem no gel togeda, wetin oyibo pipo dey call 'chemistry', as dem no feel say di two of dem connect well. Dis one na something wey pipo no like at all as some of dia favourite artistes - even di ones wey dey nominate no show for di ceremony. One of di notable pipo wey no dey na Wizkid wey bin dey London for im Starboy Fest show. And as Naira Marley and Burna Boy perform wit am dia, dem too no show. Still, pipo no like how winners on di night no show to collect dia award. Anoda tin wey make pipo dey scratch head wonder na when Regina Daniels mama present artiste of di year award for di show. Di tok be say no be her scene and she no even dey di industry so why she go dey present for di Headies. Although e no be new tin for di Headies to use pipo wey no dey di industry to present awards. No be all complain wey pipo tok about di Headies. Some things wey happun sweet pipo for belle like how Falz carry award for im album Moral Instruction; and DJ Cuppy and Bovi wey present Hip Hop World Revelation as dem dey lick gelato. Di Headies na music award show wey dey celebrate pipo wey don do big tins for di Nigerian music industry. See di full list of all d winners for di Headies here. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50114628 +entertainment Davido birthday donation: David Adeleke N250m donation to orphanages buzz Nigerians on im 29th "'Davido' name still dey many Nigerians mouth afta di singer announce donation of all di money friends raise for am ontop social media for im birthday to orphanage. Di N250,000,000 donation to orphanage homes across Nigeria don make e fans, celebs and politicians to tok about di singer wey clock 29 years old on Sunday. One of di latest reaction na a recent tweet from Former Senate President, Dr. Abubakar Bukola Saraki. Few days ago, Davido wey im real name na David Adeleke bin put up one post say e wan raise one hundred million naira wey im wan use take clear im Rolls Royce from port as im 29th birthday dey come. Di singer begin call on im friends and associates for social media to contribute and within few hours e get more dan di hundred million e bin request. Afta everi-everi, Davido come announce on Saturday, 20 November im raise N250M and e go add N50M to make am N250M, then donate everything to orphanage. Dis announcement come a day before di singer mark e 29th birthday 21 November 2021 and e promise to do more for next year celebration. Bukola Saraki Di OBO hit maker don get thousands of retweets and mentions across Facebook and Instagram since im start to raise di money, wey im say start ""like joke."" Former Senate President, Abubakar Bukola Saraki na di latest pesin wey don react to wetin Davido announce. Dr. Saraki praise di singer for impacting lives through e music and philanthropy and pray make God continue to reward your efforts; ""Dis past week on Instagram we all watch how Davido 'playfully' raise N200 million from im friends, business associates, and oda well-wishers, then donate N250 million to orphans across di kontri."" ""Since e be young boy, Davido always get dis persuasive charm, a great deal of talent and energy. ""And e get di ability to accomplish wetin odas describe as ""impossible"" — through im sheer grit and hard work."" ""As e celebrate e birthday today, I congratulate Davido for becoming a fine young man wey continues to positively impact lives through e music and philanthropy,"" Sakari tok. Atiku Abubakar Nigeria former vice president, Atiku Abubakar also react and thank Davido for 'making di lifting of odas im cornerstone.' Atiku tweet say; ""Dear Davido thank you for making di lifting of odas a cornerstone of your endeavour."" ""I join your family and friends and millions of your fans to wish you a memorable birthday. ""I wish you more years in good health, more award-winning music and, above all, lifting odas."" Di former VP post ontop im verified account. Bisi Alimi Also, Nigerian gay rights activist, Bisi Alimi share post for im Instagram story of how e feel about Davido N250M donation to orphanage; ""So Davido dey give di money to orphanages across Nigeria? Dis no dey very interesting?"" ""You think say Davido know something wey everyone, average Nigerians no know?"" ""You think say Davido know say Nigerians na very heartless pipo dat if e ask for money for charity, nobody go show concern about giving money?"" Bisi ask. ""Deceiving Nigerians to get money to give to charities say a lot about how Nigeria as a project and Nigerians as pipo dey operate."" ""Well whatever be im intention and while we neva know, at least we know something for sure, Nigerians love shining things than dem love dia fellow humans."" Baba Fryo Meanwhile, Singer Baba Fryo do video and post for im Instagram handle say di N250m wey im dey hear from social media dey surprise am; "" I remember wen I dey depress, dem tag many of my colleagues but non of dem respond. Na pipo wey no know me respond."" ""If pesin like me wey dey popular and wey dem know, nobody fit do anything, na orphanage wey dem no know from anyway na im dem dey give N250m. E dey so funny."" Baba Fryo tok. Di singer say im go advise Nigerians to wise up. E add say no be say im dey against giving Orphanage money but di whole thing dey funny to am. Baba Fryo continue to tok about di mata and say if pipo like make dem abuse but e don tok e mind. Reno Omokri Reno Omokri wey be former special assistant to Nigeria former President, Goodluck Jonathan say Davido dey much wiser than those wey contribute money give am. Reno tweet dis one afta di singer announce say e dey donate all di money give orphanage. ""Davido dey much wiser than those wey give am monies. E understands di spiritual realm and di ways of God,"" Reno tok. ""E don secure soft spot for di Heart of God by virtue of James 1:27. I commend am. What a heart of Gold. Those wey give to am need to read Proverbs 22:16."" Here na oda reactions from Nigerians and fans of di singer Dis add join to di viral skits wey some Nigerian comedians don post sake of Davido Donation. Earlier music producer Don Jazzy, Nigerian socialite Obi Cubana and singers Teni Entertainer and Simi all react to Davido donation. Nigerian musician, Davido don make many music since im start im career for 2010. Born on 21 November, 1992 di Nigerian-American singer na heavyweight for Nigerian music industry Forbes for 2020 label Davido as Afrobeats superstar. Dem say e be one of Africa biggest musicians. Since im rise to fame, Davido don win multiple awards, including BET awards and MTV awards. He also dey signed on many endorsement. For 2008, he make di Forbes Africa 30 Under 30 list. Davido get 9.7 million followers on Twitter." https://www.bbc.com/pidgin/media-59367085 +entertainment BBNaija 2020 housemate Nengi, Trikytee don become Bayelsa state Senior special assistants Former Big Brother Naija housemates, Nengi and Trikytee don collect appointment as Senior Special Assistant to Bayelsa State governor, Douye Diri. Governor, Douye Diri, announces Nengi Rebecca Hampton wey come out as second runner-up for di reality TV show as face of Bayelsa Girl Child. Di Bayelsa State governor say e dey proud of di housemates wey come from di State and advise her to continue to exhibit her humble and good characters for di house even in real life. Nengi say she get passion to support girl child to di best of her ability and she wan also use her voice to fight gender based violence based on say she don experience am first hand. Director/ Cordinator of New Media Bayelsa State Goment, Kola Oredipe say di Govnor also don appoint di oda BBNaija Lockdown housemate from Bayelsa, Tommy Sinclair, AKA Trickytee as im Senior Special Assistant SSA. Though dem neva announce which portfolio Trikytee go hold. Trikytee thank di Govnor of Bayelsa State say na big honor for am and im dey grateful for di appointment. Dia fellow former Big Brother Naija housemates and Fans of di reality TV show don enta social media to begin congratulate dem. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54842458 +entertainment BBNaija: Erica, Prince, odas reveal ‘tins’ for Big Brother Naija Diary room challenge wey happun among housemates "For di start of dis week, Big Brother collect leave come leave HoH Kiddwaya in charge, question wey bin dey for pipo mind be say who go run diary room. But on Thursday, challenge come say make di housemates dem be each other ""biggie"" and di tea wey comot di mata no be small. Di rules na say pipo go pick dia ""biggie"" randomly from box Dis na some of di tins dem tok. Afta di gbas gbos wey happun between Erica and Wathoni before dis challenge, na Erica come pick Wathoni as her biggie oh. Erica reveal during dia yan say she recently find her papa on top social media and neva even meet di guy for real life as she still dey reason di mata. On top di mata, she tok sorry say she no mean to insult Wathoni on top say she be single mama because na single mama sef raise am. Prince reveal for im own diary session wey na Erica be im biggie say, if e fit break up any couple for di house, e go be Erica and Kiddwaya straight to her face. E say di mata go end for premium tears on top say Kiddwaya just dey infatuated with Erica and im admire Erica na why e tok like dat. One of di questions for di 'biggie' session na who you go ship with. Trikytee with no regret say e go choose Dorothy sharparly. E tok say e for pick Wathoni except di wahala inside be say she too dey emotional.m.?" https://www.bbc.com/pidgin/tori-53843315 +entertainment BBNaija: Ozo, Dorathy na head of house and deputy for week 3 for Big Brother Naija 2020 season 5 show Ozo snatch di Head of House (HoH) seat from Lucy afta im win di HoH Challenge on Monday August 3 come nominate Dorathy as im deputy. Im be di first man to win di HOH title afta Nengi and Lucy win am for dia first and second week for di house. As Head of House, Ozo get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week. Im also get power to pick deputy, first, second and third choice. Ozo pick Dorathy as im first choice, Nengi as second and Erica as third choice. Na Nengi bin win di first head of house challenge and during her reign, di house lose dia weekly wager. As tins be, 16 housemates dey up for possible eviction dis week out of di 18 wey still remain for di house. Di housemates don spend three weeks inside dia ten weeks journey for di house. 16 housemates dey up for possible eviction dis week out of di 18 wey still remain for di house. On Sunday, Ka3na and Lilo comot for di house afta di first eviction show wey happun on Sunday. See di full list: Voting go start on Monday and end on Thursday August 6. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53641155 +entertainment Jennifer Lopez album covers: J.Lo new single 'in the morning' cover foto make fans para "Jennifer Lopez AKA J.Lo wey be American actress and singer drop new album on Friday but belle no sweet most of her fans sake of di cover photo. Di 51 year old singer and dancer post a naked full side picture of herself as di cover art of her new single ""in the morning"". JLo wey release dey popular for her stylish fashion sense wey dey always break di internet but dis time, some of her fans feel say, stepping out in her 'birthday suit' fit dey too much. Dem tok say di picture no dey appropriate, as e make yeye alias undermine di equality wey women don fight for. Some of her fans still hail her and dem admire how she showcase her body and di ogbonge work wey she dey do to keep fit and healthy even at age 51. Dem see her as inspiration. As of 2017, di award winning singer [Jennifer Lopez] don sell more than 70 million record worldwide. One of di songs for di album ""in the morning"", na about love. For one interview wey Jlo bin do wit di Wall Street Journal Magazine, she say ""E get sometin wey dey inside me wey wan endure."" ""I feel youthful and I feel powerful and I wan show women how to dey powerful."" Jennifer Lopez no be di first pesin to enta kasala wit fans sake of naked photo, entertainers like Kim Kardashian, Cardi B don also dey di table before now." https://www.bbc.com/pidgin/world-55112940 +entertainment Sean Imonioro Chukwuemeka: 26yr-old Nigerian marry 56yr old woman e meet for Facebook """I no dey see di age gap dia, I no dey notice di age, e just be like say na my age mate, na my best friend I marry"". Na so one 26 years old Sean Imonioro Chukwuemeka wey marry 54 years old woman tok. Sean na local footballer wey dey play for Owerri in Imo state and e also dey do Point of Sale (POS) money transfer business to take hold bodi. E say di two of dem be meet for Facebook for 2020 and from dia di love wantintin begin till e propose to am. ""As we take meet ourselves, we plan say e go be like dat, because na for January 2020 I see am for my Facebook under pipo you may know. ""I begin view her profile, di woman comments and tins wey she dey put for her post, i come like her post dem, send her message, na so we take start"". Di woman bin get three children before dem marry but im say e no dey worry about menopause as pipo dey warn am say di woman no go fit born pikin for am. ""But e say im no believe say menopause exist as nothing wey be like menopause for God side as fit give anybody pikin anytime, Sean say e dey for bible. According to Sean Imonioro Chukwuemeka di difference for dating or marrying pesin wey old pass you na just say you know as trust dey there, respect dey there. E add say im wife dey care for am wella unlike young ladies wey go dey complain or halla for you if you offend dem. ""She know say she give me age difference, she still dey care dey repect me. For one day, she no let me know say she be di senior for dis relationship even if we get differences, she go calm down explain to me"". Sean say im 56 years old wife dey give am all di tins wey im expect from woman for character, attitude wey im bin dey reason say im dream wife go be. E say im no marry di woman sake of say one corner corner benefit dey as pipo bion dey ask am. E say di benefit wey dey for di marriage for im na di happiness say im marry pesin wey im get peace of mind wit." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59592322 +entertainment Dimeji Bankole: Former Speaker Nigeria House of Representatives, and daughter of Kebbi state govnor wedding fotos Former speaker of di Nigeria House of Representatives, Dimeji Bankole don wed di daughter of Kebbi state govnor , Atiku Bagudu, and chairman APC Governor's forum. Bankole and im first wife bin divorce sometimes in 2017. Di couple tie di knot on Friday for Federal Capital Territory Abuja , follow by di traditional event to welcome di new bride to di Bankole's family on Saturday in Ogun state. BBC Pidgin learn say di celebration go end on Sunday wit dinner wit family and few friends at Dimeji's Apo residence. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55693914 +entertainment Wetin be Reflux Laryngitis wey force Tems to cancel her shows? "Nigeria singer Tems cancel her shows this week for United Kingdom sake of sickness. Tems reveal Tuesday June 14  for Instagram say she dey suffer from Reflux Laryngitis. “e break my heart to say dis, but I no get anoda option. I no dey feel too good at di moment. After my last performance, dem diagnose me wit Reflux Laryngitis, and I gatz take some time off to protect my voice.” Tem tok. “On doctor’s order, I don postpone di two shows dis week. Di new dates for di two shows we go announce am tomorrow.” She add Di post on her sickness don get ova 112k comment for her page. So wetin be Reflux Laryngitis dis tori go tell you wetin e be. According to University of Pittsburg Reflux laryngitis na voice disorder sake of irritation and swelling of di vocal folds due to di backflow of stomach fluids into di throat. Symptoms University of Pittsburg say di most common symptom na crack voice, wey dey worse for morning and afta pesin eat. Oda common symptoms with Reflux Laryngitis na Prevention To prevent dryness or irritation to your vocal cords: Treatment Lifestyle modifications na di first step of management. Dis includes weight loss, small meal size, refraining from lying down within 3 hours of a meal, eating food wey get low fat and low acid, avoiding carbonates or caffeinated beverages, stopping tobacco use, and reducing alcohol intake. Tems na Nigerian singer, songwriter and producer. She don release plenty singles and features wit Nigerian and international acts. Temilade Openiyi AKA Tems na 25 year-old - dem born for July 23, 1996. She bin study Economics for one University in South Africa. Dis na afta she attend Dowen College for Lagos. Raised by her mama, Tems start her own music production at di age of 20. Tems, wey be strong listener of Aṣa, Adele, Lojay, and Zinloeesky songs, no feel like a new comer for dis music game., according to one BET report. Born in Nigeria, di Yoruba meaning behind Tems real name Temilade Openiyi na ""my own na di crown"". On August 31, 2021, di Nigerian singer become BET Amplified Artist of The Month of August 2021." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cmlee7lr829o +health Omicron Covid: UK record first death from Omicron variant of Coronavirus "One pesin for UK don die from di Omicron variant of coronavirus, di prime minister tok. Boris Johnson tok say di new variant dey also result to hospital admissions and di ""best thing"" pipo fit do na to get dia booster jab. During im visit to one vaccination clinic inside London, e say make pipo put for corner di idea wey say Omicron na milder variant. On Sunday, di Prime Minister set new target for all adults inside England to offer dem booster by di end of di month. Speaking during one visit near Paddington, west London, oga Johnson tok say: ""Sadly yes Omicron dey produce hospitalisations and sadly at least dem don confam say one patient die with Omicron. ""So I think di idea say dis na somehow milder version of di virus, na something we need to set on one side and just recognise di pace wey e dey increase through di population."" On Monday, Health Secretary Sajid Javid tok say 10 pipo dey for hospital inside England with di Omicron variant. Sake of cases of di new variant of coronavirus, Omicron, UK update number of kontris wey dey dia travel red list last week. UK add Nigeria, South Africa, Angola, Botswana, Eswatini and some oda African kontres to di red list." https://www.bbc.com/pidgin/59639398 +health Coronavirus: Meet di dogs wey UK goment wan train to smell coronavirus "Test don begin for Britain to see if dogs fit use dia ogbonge nose smell coronavirus. Dogs don already sabi how to use dia nose to detect pipo wey get malaria, Parkinson's disease and some types of cancer. Now, authorities for UK dey hope say di same fit happun for coronavirus wit six special dogs dem wey dem go use four to six weeks train. Di UK goment comot £500,000 to use support di project. Dia plan be say dem go use dis dogs test pipo wey dey enter di kontri through places like airports, and e go fit test 250 pipo in one hour. Dr Claire Guest wey follow dey train dis dogs say: ""Di plan na say dis dogs go fit test anybody, even those wey dia symptoms never show. E go dey fast, effective and e no go touch pesin body."" UK no be di first to begin do dis Covid-19 dog training as France bin don get one similar program wey dem start for April." https://www.bbc.com/pidgin/world-52727985 +health Lagos State goment close down hospital afta 'first time' mother die during Childbirth "Di Lagos State goment don close down one hospital for di state afta report say dem dey incompetent. Goment take di action afta report come out say Vivian Nwachukwu, wey be first time mother die for di hospital during child birth. Na di Health facility monitoring and accreditation agency (HEFAMAA) of di state goment close di hospital. Di incident happun on 28 March for Okota area of Lagos. Chibuike Nwachukwu, husband of di late woman tell BBC Pidgin say im wife bin no get complications during her pregnancy. ""I dey Enugu state when everi tin happun,"" e tok. Di man say ""my wife undergo antenatal for di hospital until on Sunday 28th March 2022. ""She do all di tins including scans and tests wey she suppose do and she dey very ok. Nwachukwu say im wife chat am up to give am update of how evri tin dey go wen she enta labour. ""Di hospital tell am to come wen she tell dem say her water don break. As she reach dia dem induce her to speed up labour. ""For some time I no fit reach her again until around 2am for midnight wey I get call from my sister wey dey wit her say dem need blood."" Nwachukwu say im try to get di blood but im come begin dey uncomfortable, ""wen I hear say dem say dem wan cut off my wife womb. Dis na afta she don lose blood"". Di middle aged man say im 28-years-old wife die before im reach Lagos - ""I try get five pints of blood."" E say sake of how di night don go im no fit endure to wait for any tine, ""I just beg my friend to help book flight wey carry me come Lagos. ""As I reach di hospital I see my wife deady body inside one place wey dem say na theatre. ""Mind you, I was in Enugu while all this was happening."" Di man carry di matter go social media wey attract goment intervention. Commissioner of Health for Lagos, Akin Abayomi, post for im official twitter handle say goment don seal di hospital. E say na di state health agency, Hefamaa seal di hospital. But di Executive Secretary of di Agency, Dr Abiola Idowu say dem seal di hospital ""for not was complying wit set standards."" She say investigation show say di hospital no register wit di agency. ""Dia non registration contravene di 2006 Health Sector Reform Law. ""E mean say di facility dey operate illegally. Di team also discover say di hospital no get enough staff"". Im say di agency dey investigate di death of 28 year old Vivian Nwachukwu, adding say di hospital go dey closed in oda to protect di public. In di meantime, her husband, Chibuike Nwachukwu say di son dey alive but e dey take treatment for intensive care unit ""afta everi tin wey happun to am."" Family don fix di burial for di late woman to hold on Saturday 9 April." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61022470 +health """Vaccines"" in Ghana: Covax Covid-19 vaccination - How Ghana plan phase by phase injection" Ghana goment collect Covax vaccines first batch of 600,000 doses on Tuesday and dem go conduct dia Covid-19 vaccination phase by phase for different groups of pipo for di west African kontri. For statement wey di Ministry of Information release, beginning from March 2, 2021, dem go move di Covid-19 vaccines go health centres plus oda centres wey goment a approve for different regions of di kontri. Di authorities say di first groups of pipo wey dem go begin vaccinate na health workers, pipo wey dey 60 year and ova, pipo wey gt underlying health problem, frontline executive, members of parliament, judiciary and dia staff, frontline security personnel, some religious leaders, essential workers, teachers plus oda personalities for di Greater Accra Metro including Awutu, Senya and Awutu Senya East for di Central Region. Dem go also vaccinate pipo wey wey dey inside dis group wey dey live for Greater Kumasi Metro and Obuasi municipality. On Tuesday 24 February, plane wey carry 600,000 doses of Covid-19 vaccine wey COVID-Vaccine Global Access Facility (COVAX) dey organise don land Accra, Ghana. Dis one make Ghana di first African kontri to receive coronavirus vaccine through COVAX wey be world programme wey World Health Organisation create to make sure dem share vaccine fairly among kontris. Unicef say dem choose di kontri to collect di Oxford AstraZeneca vaccine because dem ready to begin vaccination. Ghana dey among di 92 kontri for world wey wey be part of di WHO programme. https://www.bbc.com/pidgin/media-56185404 +health Coronavirus guidelines: Why kontris wey women dey lead dey respond well to di Covid-19 pandemic? "From New Zealand to Germany, Taiwan or Norway, some kontris wey women dey lead dey see small number of death sake of Covid-19. And dem dey praise dia politicians for media for dia behaviour, and also for di solutions wey dem introduce as di whole world dey face dis health palava. Recently tori pipo, Forbes write say dem be ""example of true leadership."" Analysts say di pipo wey pass di Covid-19 test wit flying colours na women - even though women make up only 7% of di world head of kontris. So, wetin make am look like say women leaders dey successful pass for di fight against coronavirus pandemic. Iceland Prime Minister Katrin Jakobsdottir don do plenty testing for her pipo. Even though di kontri population na 360,000, Iceland no dull at all: Dem do tins against Covid-19 - like dem no allow pipo gada pass 20 - wey dem do till end of January, before dem even record dia first case of di disease. As of April 20, na nine pipo don die for di kontri from Covid-19. For Taiwan wey officially be part of China, President Tsai Ing-wen immediately set up epidemic control centre and she do tins to track and control spread of infection. Taiwan also increase production of personal protective equipment like face masks. So far na only six pipo don die out of 24 million pipo. Meanwhile for New Zealand, Prime Minister Jacinda Ardern, take one of di world toughest decisions for dis Covid-19 palava. Instead of to slow di amount of infection or ""flatten di curve"" like oyibo go tok, of reported cases like many kontris dey try do, Ardern style na to cut off all di infection pkatapkata. Di kontri enta lockdown wen only six pipo die - and by April 20 na total of 12 pipo die. But, apart from say all of dem get women as dia leader, dis kontris wey handle di crisis beta still get oda tins in common: All dis kontris dey developed and dem get moni, wit beta system for welfare and dem dey mostly score wella wen e come to social development. Again dem get strong healthcare system wey fit to handle emergency. So, dis na about di leaders demsef - abi na about wetin we fit tok about kontri wey get woman as leader? Di way wey dis women leaders wey dem elect for office dey do dia own politics also get hand for di mata, na so observers tok. !I no tink say women get one style of leadership wey different from men. But wen women dey leadership, e dey bring variety to decision making,"" na one Dr Geeta Rao Gupta, di executive director of 3D Programme for Girl and Women and senior fellow for UN Foundation, tok. ""E dey create beta decision, because you go get di opinion of men and women,"" she tell BBC. E dey different from di macho way and denying science wey dia male counterpart bin display, from America Presido Donald Trump to Brazil Jair Bolsonaro. Rosie Campbell, director of Global Institute for Women's Leadership for King's College London, agree say ""dem no born any man or women wit leadership style."" ""But due to how society take raise us, e dey more acceptable for women to be leader wey get human feeling and wey dey collabo. And unfortunately more men dey for category of pipo wey too dey admire dem sef and over competition dey worry dem, Campbell tok. Political leaders for Brazil, Israel and Hungary, to list few kontris don try for some kain situation, shift di blame for dia fault to outsiders - like dem go accuse foreigners for ""importing di disease"" enta dia kontri. ""Trump and Bolsonaro dey choose to form macho. Dem no born dem to behave like dat, but na dem choose to,"" Prof campbell tok. ""Women generally no dey like dat. But dem still get exception, like Marine Le Pen [for France]."" Different kontri respond in different ways to di Covid-19, partly becos each kontri get im own social and economic mata and even resources - dis aspects no get anytin to do wit gender. Therefore, leader wey be man but no follow for di macho group wey Prof Campbell describe also get less death for dia kontris. Di way South Korea, Moon Jae-in take handle di crisis show di basis wey im party take win landslide victory for di last parliamentary election wey happun on April 15. Also Greece Prime Minister Kyriakos Mitsotakis don chop praise sake of how im successfully manage di crisis and keep di number of death as low as - 114 as at April 20 for population of 11 million pipo. Compare am to Italy wey get 60 million pipo and don see 22,000 deaths. Greece dey survive di crisis by following di advice of sabi pipo for science and im begin social distancing before dem even record di first death. Den again, some kontris wey women dey lead dey struggle wit di virus as e dey spread far and fast. For example, Bangladesh Prime Minister Sheikh Hasina don manage to reduce di outbreak for one of di kontris wey get di most population for world. But di worry be say di kontri no too get wetin dem need to do testing and Bangaldesh health workers say dem dey risk of catching di virus as dem no get personal protective equipments. To stop di coronavirus, leaders have to make difficult decisions, like to close dia economy for di early stage of di pandemic. But dat kain decision get short time political implications, na so Prof Campbell tok. Still some female leaders don win public opinion as dem dey tok coro-coro about di challenge wey dia kontris dey face. Germany Angela Merkel quickly agree say Covid-19 na ""very serious"" threat. Her kontri set up di largest testing, tracing and isolation plan for di whole of Europe. More dan 4,600 pipo die from Covid-19 for Germany wey get population of 83 million pipo. For Norway and Denmark, di method wey di two women Prime Ministers use set dem apart from dia bragado male counterpart. Norway leader, Erna Solberg, and her counterpart for Denmark, Mette Frederiksen, do press conferences for children, dem no allow any adult enta. New Zealand Jacinda Ardern also try calm children about how dem no go fit celebrate Easter sake of lockdown. Prof Campbell say, back in di days dem for consider dat kain tok private mata, just like case of domestic violence and childcare. So, by talking to children, political leaders show say dem understand say di pandemic dey also affect di mental health of pipo for evri age, na so she tok." https://www.bbc.com/pidgin/52371622 +health Coronavirus tips: WHO say Africa go get 220 million Covid-19 vaccine dose Di World Health Organization (WHO) don say once Covid-19 special injections alias vaccine dey approved and Africa go get at least 220 million initial doses. Di first batch go be specially for front-line healthcare workers and vulnerable groups, according to di WHO Africa Program Area Manager Richard Mihigo. He say distribution go dey base on di population of each kontri. Mr Mihigo say all 54 kontris don show interest for di Covid-19 vaccine. Africa get population of more than 1.3 billion pipo. Di global vaccine initiative, called COVAX, wan help buy and distribute 2 billion doses of approve vaccines by di end of 2021. Di initiative get nine vaccine candidates wey dem dey test globally. Two of di vaccine candidates dey currently test for Africa, according to di Coalition for Epidemic Preparedness Innovations (CEPI) boss Richard Hatchett. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54024540 +health Ebola outbreak 2021 in Guinea: Ebola epidemic dey declared over for Guinea afta e kill 12 Health authorities for Guinea don dey celebrate di end of di deadly Ebola outbreak wey dem discover for February 2021. Di celebration dey come afta di West African kontri no record any new cases of di virus for six weeks. Twelve pipo don die sake of di outbreak of di virus since Guinea goment declare say dem dey deal wit Ebola outbreak. Di World Health Organization hail di way Guinea take respond to virus. WHO say e help stop di repeat of di Ebola crisis wey happun for 2013 - 2016. Di outbreak that time lead to di death of more than 11, 000 pipo for Guinea, Liberia and Sierra Leone. WHO say Guinea fit contain di spread of Ebola sake of di new innovations and lessons dem don learn from previous outbreaks. Goment set up treatment centres across di kontri wey allow health workers to respond sharp-sharp. Thousands of pipo collect vaccination dis year wey make sure say dos wey dey treat Ebola patients no catch di disease. WHO say di success of Guinea show how outbreak fit dey controlled wit di combination of community engagement, effective public health measures and di equitable use of vaccines. One nurse wey work for one health centre for Goueké, near di south-eastern city of Nzérékoré, die on 28 January and dem do her burial four days later. All di pipo wey dey infected for di funeral of di nurse dey over di age of 25, according to health officials. Community funerals, wia pipo go follow help to wash di bodi of pesin wey dies , fit be way to spread Ebola wen e dey di early stage. Di bodi of victims dey very dangerous. Di incubation period fit last from two days to three weeks. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57539982 +health Coronavirus in Ghana: Senior Minister Yaw Osafo-Maafo test positive as total Covid-19 case count cross 20,000 "Ghana Senior Minister, Yaw Osafo-Maafo be de latest govment functionary to test positive for Covid-19. Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah make dis public during dema weekly update after de Senior Minister give am permission to disclose en status in de spirit of transparency. ""Dem inform de Senior Minister say en sample wey dem test return positive. He go start treatment of Covid-19 from today (June 7, 2020) for en house."" Meanwhile, Ghana Covid-19 cases cross rise catch 21,077 out of which some 16,070 people recover. So far health officials say people wey die of Covid-19 be 129. Some top government functionaries like Health Minister, Kwaku Agyeman Manu, Deputy Trade Minister, Carlos Ahenkorah and others contract de disease. At least two govment functionaries, Kwadwo Owusu Afriyie who head Forestry Commission den Secondi-Takoradi Mayor, Kwabena Kurentsi Sam die of de virus. Ghanaian Prez Nana Akufo-Addo announce say he go dey inside self-isolation for 14 days after he make exposed to de virus after someone for en close circles contract de virus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53323306 +health Coronavirus update: How pipo di live wit fear for bullet and Corona for Anglophone regions "As e be now, pipo for Northwest and Southwest regions for Cameroon di face two enemies, gunshots, kidnappings, burning of houses and Coronavirus. Just now, Cameroon Covid-19 cases don pass 1000, 42 pipo die, 305 pipo don well eight regions don confirm cases, though Northwest Cameroon nova yet enta de dance since weh Cameroon confirm first case for March 6 Southwest don confirm 11 case. Discussions don shift for de two regions as plenti groups dem di talk how for prevent Coronavirus, share hand sanitiser, masks and soap for kontri pipo for up kontri, but fear for stray bullet dey for mind wit gunshots for some parts. Anglophone regions for Cameroon don di suffer since crisis weh e start for 2016, turn to fight between goment forces and separatist fighters. ""Wen Corona sensitisation start and separatists shoot, all man di run for e life. Kontri pipo dey between rock and hard place"". Na so Melanie Ndefru, tori woman and e family di live for middle crossfire and Coronavirus for Bamenda, Northwest Cameroon. Ndefru e family di stay for de hot area, Mankon where suspect say na hideout for separatist fighters for Bamenda, and di run from taim to taim wen tins worse. ""Gunshots na de music we di hear all taim and kontri pipo dey now for middle hard rock and hard place wit dis new sick, Corona"", Ndefru tok. Buea for Southwest region weh deh get about 11 cases for Covid-19, Mme Omam Esther Njomo, sabi pesin for development work and e family di try for confine demselves for house. ""We bi check say wit Covid-19, Anglophone crisis no stop small, but dis na de period weh we di suffer more. We di get strange warnings and intimidation for phones, so we di still live inside fear from separatists and Corona', Omam tok. ""Saturday, some gunmen seize car from one of our mimba wit all e documents inside. So we di ask we self which wrong we do for dat kain suffer"", Omam add. Even if gunshots reduce for Buea, deh di still respect ghost town, most shop still be closed, deh still kidnap pikin dem for Bonakanda last week and e di still happen from taim to taim. For Muyuka, Meme and Ndian, for Southwest region, gunshots still dey and fight di go on too for Northwest region. Omam di wanda weda de fighters no know weti de world di go through now. Wen all man get for check strategy, put effort make pipo survive. Separatist group, Southern Cameroons Defence Forces, SOCADEF bi say deh wan stop fight for some taim helep fight Covid-19. But some groups still di still fight and na plenti dey for ground. UN Secretary General, Antonio Guterres don call on armed groups for de world make deh drop dia guns so dat de world go face one enemy, Covid-19." https://www.bbc.com/pidgin/52358026 +health Coronavirus - Virus: Ghana schools closed, religious, sports activities chop ban to fight Covid-19 disease "Ghana govment impose ban on all public gatherings like conferences, funerals, festivals, political rallies, Church services, Islamic worship for 4 weeks starting Monday, 16th March, 2020. President Nana Akufo-Addo announce de ban for national address inside Sunday night after inter-ministerial committee on coronavirus response meeting. After deliberations govment review de public gathering advisory for de protection of Ghanaians. Govment shut down all schools and Universities whether public or private sake of coronavirus outbreak starting today for de next four weeks. Dis move according to govment dey in line plus dema plans to ensure public safety and protection of de Ghanaian population. According to de President, he task Ministry of Education, plus Ministry of Communication for roll out distance learning give students.Meanwhile, BECE and WASSCE candidates who dey prepare for examinations go attend school to prepare for dema exams except say school authorities for ensure dem dey practice safe social distancing protocols. Despite de ban on funerals, govment say private funerals go fit happen. He point out say such funerals for no exceed 25 people. ""Private burials go fit happen, but with limited numbers, wey no dey pass twenty-five people in attendance"" Prez Nana Akufo-Addo add. Also political rallies, sporting events and religious activities, like church services in churches den mosques all chop de ban some from today till de next four weeks. Dis mean say de Ghana Premier League which Ghana Football Association np suspend despite de outbreak of covid-19 go dey on hold. Govment say businesses den workplaces fit continue to operate, but dem for observe social distancing between patrons and staff. Also establishments like supermarkets, shopping malls, restaurants, night clubs, hotels den drinking spots for observe enhanced hygiene procedures by providing, hand sanitizers, running water den soap for washing of hands. Ministry of Transport according to govment for work plus de transport unions den private and public transport operators to ensure say enhanced hygienic conditions dey all vehicles and terminals. To do dis dem for provide hand sanitizers, running water and soap for washing of hands den stuff. Ministry of Local Govment and Rural Development go also work plus Metropolitan, Municipal and District Assemblies to ensure say markets across de country dey practice enhanced hygiene conditions. Director of Public Health for Ghana Health Service, Dr Badu Sarkodie talk Ghanaians on Sunday afternoon say de total number of cazes for Ghana rise catch six. Ghana confirm de first two cases on Thursday, March 12, 2020. On Friday 13th March, 2020 de country san record two more cases of covid-19. Wey on Saturday, 14th March, 2020 dem san record another two cases of covid-19. So far five of de cases dey Accra wey one dey Ashanti Region. President Akufo-Addo talk say so far all de six cases wey Ghana record be imported, de measures wey authorities roll out go ensure say de country fit contain de virus den prevent community outbreaks. Ghana govment on Sunday announce new travel advise give all travelers after de country record four new cases of covid-19 from travelers wey enter de country. According to Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah, dem give airlines strong instructions say make dem no allow people wey travel from countries wey get over 200 cases of COVID-19 from joining dema flights to Ghana. ""We strongly discourage all travels to Ghana at dis stage until further notice."" ""Any traveller unless dem be Ghanaian citizens wey visit country wey record at least 200 cases of COVID-19 no go enter de Ghanaian jurisdiction"" Mr Oppong Nkrumah talk. Last Wednesday, World Health Organization, di ogbonga joinbodi on health mata for world, declare coronavirus as pandemic wey mean say e don dey every where for world. According to di According to di Worldometer, na at least 6,518 pipo don die from di virus so far and na at least 169,610 pipo don get di Covid 19 disease for more than 150 kontris." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51904164 +health Ghana Omicron variant: Ghana dey start contact tracing after recording new Covid-19 Omicron variant "Ghana start dey explore contact tracing after dem record first cases of Covid-19 Omicron variant. Ghanaian detect de Omicron variant along de entry borders from people who dey travel from Nigeria den South Africa. Director General for Ghana Health Service, Dr Kumah Aboagye talk media say ""through de robust testing for Kotoka International Airport, Ghana detect de Omicron variant already which dey come from Nigeria den South Africa."" Health Minister, Kwaku Agyeman-Manu for statement say de West African kontri need to implement strong measures as Covid-19 cases for Ghana don reach high levels. De minister say now e dey mandatory for all civil servants, including health workers, security personnel, and teachers, to collect vaccine against Covid-19. Health Officials for de country say dem no discover any community spread yet, but dem initiate mandatory protocols which go ensure dis virus no go spread. Dem say dem dey monitor de potential spread in local population, meanwhile dem encourage de public to continue plus de Covid-19 prevention protocols. Scientists discover first case of de Omicron variant from South Africa. Since then World Health Organisation (WHO) say de new variant spread go 23 countries as of Wednesday, November 30. Ghana Medical Association say Govment of Ghana for dey on high alert to ensure say de possible spread of Omicron variant go be minimized. Dem explain say despite say we do well identify cases for Kotoka International Airport, de danger be say someone get Omicron wey e dey incubate am within de community. Sake of that dem for dey on high alert so say de country go fit detect and prevent spread. Ghana record over 130,000 Covid-19 cases since de first case around March last year. Out of dis figure, de virus kill over 1,200 people out of which some 129,000 recover." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59501396 +health AstraZeneca vaccine side effects blood clot: COVID-19 vaccine in Ghana - FDA update "Ghana Food and Drugs Authority [FDA] deny claims say AstraZeneca vaccine dey cause blood clots in some people. However, AstraZeneca Covid-19 vaccine side effects concerns dey spread across Ghana after news emerge say AstraZeneca special prevention injection dey give severe side effects like blood clots. Sake of dis countries like France, Germany den six other countries shun dey give de AstraZeneca vaccine to de public. But according to FDA contrary to de claims, dem no record any case of blood clots for Ghana in people wey take de vaccine. Some Ghanaians who take de vaccine reveal say dem experience side effects which make dem fall sick for days.Food and Drugs Authority (FDA) for Ghana deny claims say AstraZeneca vaccine dey cause blood clots in some people. ""I develop severe headache, body weakness, waist pains, chills den fever after I take de vaccine. Dis start one day after I take de vaccine,"" Gertrude Asamoah talk BBC Pidgin."" As I go hospital saf, I notice say dem admit one person who take de vaccine plus me"" she add. Other Ghanaians who take de vaccine share similar experiences, but according to de FDA dis be normal. Health Officials for Ghana say dem set up Joint Covid-19 Safety Review Committee (JCVSRC) which go look into all de reported adverse issues associated to de vaccines. Dem encourage Ghanaians say dem for take de vaccine." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56432438 +health Coronavirus update: Latest guidelines for Africans wey wan travel go America "America don release new guidelines for travellers wey wan enta di kontri by flight. Di new guidelines go dey effective from January 2021. For inside one document wey di US Center for Disease Control release for dia website, e say all air travellers wey dey travel go di kontri must provide negative Covid-19 test result or document wey show say dem don recover from di disease for pipo wey bin test positive. Dis rule apply to all air passengers, from two years old wey wan travel go US, including US citizens and legal permanent residents. Di agency also answer some questions pipo fit dey ask about di new travelling rules You go do test three days to wen your flight go depart go US. Make sure to dey tested with a viral test (NAAT or antigen test) to determine if you na now-now you catch COVID-19. Also make sure say you collect your results before your flight depart and get documentation of your results to show di airline. You go fit travel instead with documentation of your positive viral test results and a letter from your healthcare provider or a public health official wey tok say you dey clear to for travel. Di positive test result and letter together dey referred to as ""documentation of recovery."" Di airline go confirm a COVID-19 negative test result or documentation of recovery for all passengers before boarding. CDC recommend say make travellers get tested 3-5 days after travel AND stay home or otherwise self-quarantine for 7 days after travel. Even if you test negative, stay home for di full 7 days. If you no do test again, e dey safe to stay at home for 10 days. Dis order applies to all flights, including private flights and general aviation aircraft (charter flights). Passengers travelling by air into di US dey required to have proof of testing regardless of flight type. If your flight dey delayed before departure, you go need do di test again if di delay cause your test to fall outside di 3-day pre-departure testing period requirement. Yes. Any flight wey dey enta di US, even if na for connection, go need do test before dem comot. Yes, all air passengers travelling to di US, regardless of vaccination status, must provide a negative COVID-19 test result or documentation of recovery." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55683765 +health Coronavirus: Ghana ban travellers from kontris wey record over 200 covid-19 cases from entry "Government announce new travel advise give all travelers after de country record four new cases of covid-19 from travelers wey enter de country. According to Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah, dem give airlines strong instructions say make dem no allow people wey travel from countries wey get over 200 cases of COVID-19 from joining dema flights to Ghana. ""We strongly discourage all travels to Ghana at dis stage until further notice."" ""Any traveller unless dem be Ghanaian citizens wey visit kontri wey record at least 200 cases of COVID-19 no go enter de Ghanaian jurisdiction"" Mr Oppong Nkrumah talk. Govment make dis announcement for press briefing under today after de country record four new coronavirus cases which increase total cases to six for Ghana. Authorities also say dem dey strongly discourage Ghanaians from travelling around dis time sake of de outbreak. If you no dey fall inside de category wey dem bam, authorities say you for go through mandatory 14 days self quarantine. Dis go help reduce possible infection of other people if such travellers like Ghanaian citizens wey enter de country get de virus low key. President Akufo-Addo last week announce $100 million monies wey de country go take deal plus coronavirus. Authorities for Ghana say dem dey step up dema plans to deal plus dis global pandemic. University of Ghana (UG) say dem suspend lectures for campus after one of dema students test positive for coronavirus. According to de University, de non-residential student return to Ghana from international trip. Dis student be one of de cases wey increase Ghana covid-19 cases to total of six. Sake of de case wey dem record management say dem dey suspend all University of Ghana campuses, including clinicals and practicals, with immediate effect. ""As a result of de suspension all students, staff who dey leave outside UG campuses wey dem currently dey off campus for stay away from de school until further notice"" de official statement from Registrar reveal. Meanwhile, Vice-Chancellor, Professor Ebenezer Oduro Owusu also make de announcement give students for de campus radio top, Radio Universe. University of Ghana et student population of about 40,000, some be resident students while others be non-resident. Management of de school advise students say make dem practice safety measures like distance from people wey dem also suspend de hosting of international visitors until further notice. De University say dem provide hand sanitizers give students for de various halls of residence." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51898668 +health Ghana Medical Association suspend dema planned strike action "Members of de Ghana Medical Association (GMA) say dem call off de planned strike action which for start today, November 18. Ghanaian doctors, last week threatened govment say dem go withdraw dema services if govment fail to review dema conditions of service. As part of dema demands, de GMA say dem want 40% of dema basic salaries as accommodation allowance per month, 20 percent as dema core duty facilitation allowance. Also dem demand for 30% clothing allowance, 20% maintenance allowance, 20% utility allowance, 50% as professional allowance den 25% special risk allowance and vehicle tax exemption give doctors. According to Dr. Frank Ankobea, President of the Ghana Medical Association, dem ""reach agreement plus government, sake of that we suspend wanna planned strike"" De Fair Wages and Salaries Commission's (FWSC) promise say dem go sign de agreed conditions of service document give members of de Ghana Medical Association." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50458174 +health Donald Trump Jr: President Donald Trump oldest son tests positive for coronavirus "America President Donald Trump oldest son don test positive for coronavirus, according to im tok tok pesin. Donald Trump Jr, wey be 42 years old bin do test dis week and don begin quarantine for im hunting cabin since di result comot. For inside statement, di tok tok pesin say ""Im no dey show any symptoms and e dey follow all di recommended Covid-19 guidelines."" Don Jr na President Trump second pikin wey go test positive to Covid- 19. Barron Trump, wey be 14 years old, bin test positive last month, but and e quick recover. Donald Trump Jr na expert for public speaking and he play major role for im papa presidential campaign. Oga Trump sef bin test positive for beginning of October and e spend three days for hospital. First Lady Melania Trump also bin get di infection. Last month, Don Jr bin chop accuse say im no dey tok true about pipo wey don die sake of Covid- 19 for America. Di virus don infect 11.8 million Americans and more than 253,000 don die sake of am. On Friday alone, 192,000 pipo for di US tested positive for coronavirus, according to di Covid Tracking Project." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55026454 +health Coronavirus domestic violence: Surviving lockdown wen you dey trapped with your abusive partner "Di United Nations don describe violence against women during di coronavirus lockdown as ""shadow pandemic"". Across Africa, goments, police and activists report increase in attacks on women and girls wey trap for lockdown with abusive partner or relative. So wetin you fit do if you find yourself in dis kain of situation? We ask experts and one survivor of domestic abuse to share dia advice. ""Wen you dey for inside abusive relationship, you go notice one pattern,"" Esther* tell me, as she tink back to di three years she spend married to man wey she tok say bin dey abuse her regularly - physically and verbally. ""Weekends dey always worse, because everybody dey for house. Your partner get more time for dia hands and fit get bored too. So you go see say dem wan find trouble. Dem go set you up - say something wey go make you react and den hit you wen you react. ""If two days fit make pesin dey bored enough to make dem wan hit you, imagine wetin one month or so of lockdown don cause pipo. No be just boredom dis time, na stress, na fear."" Several years don pass now since Esther leave her husband. And even though, practically, e bin dey more easier to comot dan e go be today, e still take time and courage. ''I feel say I dey place wia get bars and I no fit comot because economically, emotionally, psychologically, e hard well well - and den my children dey too. Also, your mama dey happy say you don marry, so you dey reason - keep her happy. Stay.'' For women wey wan leave dia partner now during lockdown, di challenge dey even bigger. If dem try to leave, police fit challenge dem say dem break curfew and dem fit struggle to find public transport. Many kontries don set up helplines, dey offer advice and support to victims. Demand for dia services dey high. During di first week of lockdown for South Africa, police receive 2,320 reports of gender-based violence - 37% higher dan usual. For Zimbabwe, one helpline say di number of abuse cases dem document bin triple, while Nigerian gender advocate, Dorothy Njemanze, tell BBC News say she dey worried by di rise of abuse cases for her kontri: ""We fear say if e continue dis way, we fit record some deaths before di lockdown over.'' Some African states dey take practical steps to help women. For Tunisia, wey don see five-fold increase in reports of domestic violence, di goment don set up free helpline and allocate eight shelters for victims and dia children, with more facilities on di way. For some oda place dem, many shelters don manage to stay open and volunteers dey able to help women to escape. For Zimbabwe, di Roots One Stop Shelter dey currently house 21 adults and seven children. Di director, Beatrice Savadye, say dem dey manage to rescue women from dia homes and dey also get referrals from police. For Kenya also, social worker Dianah Kamande say shelters still dey able to house women and say her organisation don already rescue 17 women for Nairobi alone. For Nigeria, although most women shelters don close as part of di lockdown, volunteers still dey able to help women escape and move in with dia relatives, according to Titilayo Vivour, di coordinator for di Lagos State Domestic and Sexual Violence Response Team. But for Ghana main safe house, di Ark Shelter, director Nana Sunnu say dem dey unable to take in new clients because of di infection risk and lack of quarantine facilities. Esther, wey survive violent marriage and dey work with fellow survivors now, say make women still call di helpline even if dem dey for kontri wia di shelters dey closed. ""Try and reach out to activists wey dey for social media, activists wey you fit trust. Call dem, dem fit still do something even for dis lockdown situation.'' Make Communities also look out for neighbours wey dem tink say fit dey exposed to violence, according to South African psychologist Nthabiseng Ramothwala. She also advise women to seek help from di pipo around dem. ''Know police officers and emergency numbers you fit call,"" she tell BBC. ""Involve your neighbours as well, tell dem signs to look out for so you to know wen to help. Give dem numbers of close relatives wey fit come rescue you."" And for those wey really fit no escape, Esther get some final advice. ""You no need to stop your voice to make someone else feel better, but for dis situation, if dem tok something wey pain you, just ignore dem. If dem annoy you, go read book, do something else to take your mind away from dem. ''If you fit survive di next one or two or three months... den do whatever you need to do. I no know if we fit call these kinds of measure solutions. Dem just be stop-gap measures. ""Right now we dey try to survive, so say wetin dem need to hear, do wetin dem need you to do. Just survive dis.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52675405 +health Coronavirus news: Ivory Coast ban foreigners from kontries wit over 100 Covid-19 cases, close night clubs & cultural events Ivory Coast take strong decisions afta six cases for Covid-19 disease, stop foreigner for enta dia kontri for 15 days, close schools and restaurants. Deh take dis decision afta President Alassane Ouattara preside security council meeting with health officials for check situation for Coronavirus outbreak for di kontri. Na from France and Italy weh deh import de cases for contaminate local pipo for Abidjan, di health minister of Ivory Coast confam for statement from di Council of National Security. In addition, Ivory Coast put control for land, air and sea borders; quarantine suspects and dia contacts for some centres dem. Close schools from nursery, primary, secondary to university level for 30 days form March 16. Ivory Coast di also close night clubs, cinemas, restaurants, and big places. Stop more dan 50 pipo for gada for public for 15 days as from March 18. All sport and cultural events go mash break for 15 days. De first case don well and no cause for alarm for de odas, di statement add. For seka say na foreigners di enta Ivory Coast wit de disease, goment stop foreigner from kontris wit over 100 cases for coronavirus, for 15 days and deh fit extend'am one taim. Ivorians and oda foreigners wey dia kontri neva get up to 100 cases get 14 days quarantine once deh enta kontri. Goment don call on di kontri pipo for respect body hygiene, no touching greeting, embrace, hugs and make deh no chop bush meat again. Deh di call on traditional rulers for helep make sure say all man for Ivory Coast respect de decisions weh goment take. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51922463 +health US travel ban: South Africa, Zimbabwe, Malawi, and oda flights go dey temporarily blocked from US sake of new coronavirus variant "US go restrict travel from South Africa and seven oda southern African kontries to try to contain one new coronavirus variant wey dey spread dia. From Monday, only US citizens and residents go dey allowed to travel from di region. Dis one dey follow one similar flight ban wey EU and UK impose. Canada dey also introduce travel restrictions. Di World Health Organization (WHO) don earlier declare say di new variant dey ""of concern"", come name am Omicron. US officials say flights from South Africa, Botswana, Zimbabwe, Namibia, Lesotho, Eswatini, Mozambique and Malawi go dey blocked, dis one follow earlier moves wey EU also take. Di ban go come into effect on Monday. Inside statement, President Joe Biden say di move na ""precautionary measure"" wey dem take until sabi pipo sabi more tins about di variant. Canada dey also shut down dia borders to foreign travellers wey don recently go South Africa, Namibia, Lesotho, Botswana, Eswatini, Zimbabwe and Mozambique. Foreign citizens go dey banned from Canada if dem don go dis seven nations in di past 14 days. Dem first report di Omicron variant to di WHO from South Africa on 24 November, and since den, dem don identify am for oda kontries. South Africa health ministry don criticise di rush to impose new travel restrictions, dem call dem ""draconian"", and contrary to WHO guidance. Scientists say dem still get plenti tins to learn about di virus new mutations, and WHO say e go take a few weeks to understand di impact of di new variant, as experts dey work to determine how easily e fit transmit. WHO on Friday say first evidence suggest say di new variant carry higher risk of reinfection dan oda variants. Scientists say na di most heavily mutated version wey don show yet, e mean say Covid vaccines, wey dem design wey dem use di original strain from Wuhan, China, fit no dey as effective. Di WHO say so far, fewer dan 100 sample sequences na im dem don get report about. Dem don mainly confam cases for South Africa, but dem don also detect am for Hong Kong, Israel, Botswana and Belgium. Most of di cases for South Africa don come from di most populated province, Gauteng, of which Johannesburg na die capital city. Meanwhile, the flight bans dey threaten to separate families over di festive season." https://www.bbc.com/pidgin/world-59441919 +health Di four cough syrup wey WHO raise alarm over say dem get hand for di death of 66 pikin "Di World Health Organisation don raise alarm ova four coup syrups. Dem dey link di cough syrups to di death of 66 Children for Gambia. Di syrups dem say "" fit dey likely linked wit di acute kidney injuries and di 66 deaths among children"". Na Indian company manufacture di products, ""Maiden Pharmaceuticals, fail to provide guarantees about dia safety,"" WHO add. WHO identify di medicines dem as Promethazine Oral Solution, Kofexmalin Baby Cough Syrup, Makoff Baby Cough Syrup and Magrip N Cold Syrup. Na for Gambia dem see di four products, but tori be say ""dem fit don distribute, through black markets, to oda kontries or regions"", WHO add put, for di alert wey dem publish for dia website. Dem warn say to use am fit result in serious injury or death, especially among children. WHO intervention dey come afta medical authorities for Gambia – wey be popular tourist destination - detect increase in cases of acute kidney injury among children under di age of five for late July. But Gambia goment don suspend di use of all paracetamol syrups instead as dem tell pipo to use tablets instead. WHO say laboratory analysis of samples of di products ""confam say dem contain unacceptable amounts of diethylene glycol and ethylene glycol as contaminants"". Di substances dey toxic, and di effects ""fit include abdominal pain, vomiting, diarrhoea, inability to pass urine, headache, altered mental state and acute kidney injury wey fit lead to death,"" e add put. Gambia health officials say last month, dozens of children die, dem no give any exact number. WHO chief Tedros Ghebreyesus tok for Geneva on Wednesday say: ""Di loss of these young lives dey very painful for dia families."" WHO say India Central Drugs Standard Control Organisation show say di manufacturer fit don only supply di contaminated medications to Gambia, AFP news agency reports quote one email from di UN health agency. But WHO say di ""global exposure"" dey possible as di ""manufacturer fit don use di same contaminated material for oda products and distribute dem locally or export"" dem, di agency report. India health ministry don begin investigate di cough syrups afta World Health Organisation link dem to di death of 66 children for Gambia. WHO say di medicines contain dangerous substances wey fit cause kidney damage. Di health join body don ask for di withdrawal of di products immediately. India goment don ask WHO to share dia evidence of di link between di syrups and di deaths of di children. Di manufacturer, Maiden Pharmaceuticals, say dem dey try to find out from dia buyer for Gambia details on wetin happun. (Dis controversy na blow to India image as pharmacy of di world wey dey supply medicines to all continents)." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw4078mv1pjo +health Coronavirus vaccine: Oxford university human trials cause immune response, show positive sign inside early trial - Wetin you need to know "One coronavirus vaccine wey di University of Oxford develop dey show say e dey safe and dey trigger immune response. Di trials dem do with 1,077 pipo show say di injection lead to di making of antibodies and T-cells wey fit fight coronavirus. DiThe findings dey largely promising, but e dey too soon to know if dis wan dey enough to offer protection and den still dey carry out larger trials. Di UK don already order 100 million doses of di vaccine. Dem dey develop di vaccine - wey dem call ChAdOx1 nCoV-19 - fast-fast. Dem dey make am from one genetically engineered virus wey dey cause di common cold wey chimpanzees dey get. Dem don change am well-well, first so e no fit cause infections inside pipo and also to make am ""look"" more like coronavirus. Scientists do dis wan by transferring di genetic instructions for di coronavirus ""spike protein"" - di important tool wey e dey use to invade our cells - to di vaccine dem bin dey develop. Dis one mean say di vaccine resemble di coronavirus and di immune system fit learn how to attack am. Much of di focus on di coronavirus so far don be about antibodies, but dis na only one part of our immune defence. Antibodies na small proteins made by di immune system wey dey stick onto di surface of viruses. Neutralising antibodies fit disable di coronavirus. T-cells, one type of white blood cell, help co-ordinate di immune system and dey able to spot which of di body cells don dey infected and destroy dem. Nearly all effective vaccines induce both di antibody and T-cell response. Levels of T-cells peak 14 days afta vaccination and antibody levels peak afta 28 days. Di study never run for long enough to understand how long dem fit last, di study for di Lancet show. Di study show 90% of pipo develop neutralising antibodies afta one dose. Only ten pipo na im dem give two doses and all of dem produce neutralising antibodies. Yes, but side-effects dey. No dangerous side-effects dey from taking di vaccine, however, 70% of pipo on the trial develop either fever or headache. Di researchers say dis one fit dey managed with paracetamol. Di results so far dey promising, but dia main purpose na to ensure say di vaccine dey safe enough to give pipo. Di study no fit show whether di vaccine fit prevent pipo from becoming ill or even lessen dia symptoms of Covid-19. More dan 10,000 pipo go take part in di next stage of di trials for di UK. However, dem never expand di trial go oda kontries because levels of coronavirus dey low for di UK, making it hard to know if di vaccine dey effective. Large trial wey involve 30,000 pipo for di US as well as 2,000 for South Africa and 5,000 in Brazil go happun. E dey possible say coronavirus vaccine go past effectiveness test before di end of di year, however, e no go dey widely available. Dem go prioritize Health and care workers as well as pipo wey be Covid-19 high risk due to dia age or medical conditions. However, vaccination wey go dey widespread dey likely to be, di earliest, next year even if everything go as plan. Di Oxford vaccine no be di first to reach dis stage, with groups for di US and China also dey publish similar results. Di US company Moderna na di firstand e vaccine fit produce neutralising antibodies. Dem dey inject coronavirus RNA (di genetic code), wey go den start to dey make viral proteins in order to trigger immune response. The companies BioNtech and Pfizer companies don also get positive results with di use of dia RNA vaccine." https://www.bbc.com/pidgin/world-53477961 +health Colin Powell: Former US secretary of state die of Covid-19 complications "Di first Black US Secretary of State Colin Powell don die. Im family wey announce am say e die at di age of 84 from Covid-19 complications. Oga Powel na former top military officer wey rise to become di first African-American secretary of state for 2001 under Republican George W Bush. One statement tok say, ""We don lost a remarkable and loving husband, father, grandfather and a great American,"" ""We wan thank di medical staff ... for dia caring treatment,"" e add. Di statement say e bin don dey fully vaccinated against Covid. Oga Powell na moderate Republican wey comot from in party to endorse Barack Obama for 2008. E become trusted military adviser to some leading US politicians. He dey wounded for Vietnam during service, experience wey later help define im own military and political strategies. E be highly decorated army officer, and despite im own doubts, e help swing international opinion behind di 2003 invasion of Iraq. Colin Powell come from a humble background to become di first African-American US secretary of state. Dem born Colin Luther Powell for Harlem, New York City, on 5 April 1937, e be di son of Jamaican immigrants. Im parents originally pronounce im name wit a short ""o"" for di traditional English way, but he change di pronunciation to honour one US Army Air Corps pilot, Colin Kelly, wey dey killed shortly afta Pearl Harbor. According to Powell, im be average scholar wey leave high school wit no positive career plans. As e dey study geology for di City College of New York, e join di Reserve Officers Training Corps (ROTC), one programme wey dem design to identify future military leaders. Powell later describe am as one of di happiest experiences of im life. Afta graduation for 1958, e dey commissioned as second lieutenant for di US Army. He undergo basic training for Georgia, where dem refuse to serve am for bars and restaurants sake of im skin colour. For 1962, e be one of di thousands of advisers wey President Kennedy send go South Vietnam to help di local army against threat from di communist North. For October 2015, di ex-US Secretary of State Colin Powell bin join Nigerian musician, Olu Maintain on top stage for London to dance and sing in celebration of African culture Di America former top diplomat bin take di centre stage wit Olu Maintain to gryate wit im hit song that year ""Yahoozee."" For 1987, Powell become national security adviser. Dis na di time wey US dey involved in so-called ""dirty wars"" for South America. When George H.W. Bush enta office for 1989, e appoint Powell as Chairman of di Joint Chiefs of Staff, di highest military position for di US Department of Defense. At 52, e be di youngest officer ever to hold di post, and di first from an African-American background. E face immediate crisis when di US attack Panama for December 1989, wey comot di dictator, General Noriega, one move wey dey strongly condemned by di United Nations. Di 1990 Gulf War see di implementation of one strategy wey dey dubbed as di Powell Doctrine. Essentially, Powell believe say na until all diplomatic, political or economic fail na that time US suppose resort to military force. However, once dem launch military action, then di maximum force necessary suppose dey deployed to subdue di enemy quickly while minimising US casualties. E clash wit di new president on top di issue of allowing gay pipo to join di military and Powell no gree, and e get public disagreement wit Madeleine Albright, di then US ambassador to di UN, over military intervention for Bosnia. E comot di army for 1993 and devote im time to writing im autobiography - wey top di New York Times best-seller list - plus e engage for charity work. Since e no be military officer again, e begin chook himself inside politics. E get time wey pipo tok say e dey stand against Bill Clinton for di 1996 presidential election, but Powell decide say im lack di passion for a political career. For 2000, George W Bush appoint Powell as secretary of state, di post responsible for US relationships wit foreign countries. George W Bush dey among di first to pay tribute to ""a great public servant"" as well as ""a family man and a friend"" who ""was such a favourite of presidents wey e earn di Presidential Medal of Freedom - twice"". Former UK Prime Minister Tony Blair - wey work closely wit Powell during di early years of the Iraq War - say e be pesin of ""immense capability and integrity"" who be ""great companion, wit a lovely and self-deprecating sense of humour""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58958009 +health Coronavirus: See wetin ISIS, Boko Haram and oda jihadist leaders dey tok about Covid-19 "Di reactions of Jihadist to di Covid-19 pandemic dey different between groups, altho plenti of dem agree say na divine punishment against ""pipo wey no believe in God"". Di different opinion wey dey clear pass na been between jihadist rivals Islamic State group (IS) and al-Qaeda. As IS dey treat di pandemic as opportunity to increase attacks, al-Qaeda dey see am as chance to preach and dem don invite non-muslims to convert to Islam. All di Jihadists dey hopeful say di pandemic go affect di capacity of di military forces wey dey fight against dem and allow dem to make gains. So far, e be like say di pandemic don get little impact on jihadist activity on ground. In fact e be like say IS don increase attacks for di past two months, with dia messages. However, dis fit change if di situation dey worse for areas where dis group dey active like Africa and Middle East. For di early 2020 wen na only for Wuhan Covid-19 bin dey, jihadists bin happy say di virus na God punishment for di ""persecution"" of Uighur Muslims for China's western Xianjiang province. IS, bin look di matter in a different way. For their first comment on di mata on 6 February, IS, through iim weekly paper al-Naba, say as Covid-19 be punishment wey God send, Muslims fit no sabi say na di punishment of di Chinese for di ""persecution"" of Muslims, dem still remind dem say e fit affect di Muslims too. However, dem tok say reliogion allow am if pesin dey happy sake of im enemy downfall. Later dat month, IS rejoice wen di virus hit Iran. For March, as di virus spread to Europe and di US, jihadist groups happy more and more. dem call Covid-19 ""soldier of Allah"" wey dey punish di West for im ""sins"" and ""persecution"" of Muslims. On 22 March, as IS supporters mark di first anniversary of di group loss of Baghouz, di last pesin wey be IS backbone for eastern Syria, dem tok say di spread of di virus for di West na God punishment for Muslims wey dem kill for di Syrian village. For early April, al-Shabab hailCovid-19 as punishment from God of ""infidels"", including for dia killing of jihadist leaders for different conflict zones. Dem ask Muslims to celebrate di virus outbreak for di West. But by mid-March, as Muslims begin catch di virus all around, jihadist begin change dia message. Many of dem begin tok say Covid-19, wey dem bin tok say na ""soldier"" of God, na wake up call to humanity, including Muslims, to ""return to God"". Al-Qaeda, for example, for im first official comment on di pandemic on 31 March, tell Muslims say di spread of di virus among dem na di sake of say dem no too follow Islam and im teachings well. ""Truth be told, di arrival of dis virus to Muslim kontris na sake of our own actions. Na our fault because we don move away from di path of God "", dem tok am as dem ask Muslims to repent. For im second comment on di virus on 27 April, Somali group al-Shabab stress im position say di virus na revenge of God against pipo wey be ""infidels"", but dis time dem add ""sinful"" Muslims to di mix. Dem warn say God dey punish Muslims for ""di evil wey dey spread among them"". Dis na also Boko Haram position on 15 April. As di group leader Abu Bakr Shekau celebrate di spread of di virus for di West, he also tok say na God punishment for di sins of humanity. Shekau no support movement constraints and social distancing around di world, plus for Muslim kontris, with di freedoms wey Boko Haram militants continue to enjoy. ""You getthe virus, we get di anti-virus, wey be Allah"", im boast tok am. Even as conspiracy theories bin dey about Covid-19 say na man-made and na for one laboratory for China or di US, jihadists mostly dey believe say na God send am as a message to humans. For im weekly paper al-Naba on 26 March, IS dey yab Muslims wey dey follow ""ignorant"" theories say goment get hand to develop di virus. IS argument no be to defend di US or China, but to make sure say God alone, rather than man, dey control events of di scale of di Covid-19 pandemic. Jihadists don also criticise Western states, especially di UK and US, for di way dem no handle di crisis well. On 19 May, al-Qaeda condemn British Prime Minister Boris Johnson as im propose ""herd immunity"" strategy. For one video message, one al-Qaeda narrator say: ""Dis theory na cosmetic makeover of Darwinist theories wey don dey di Western psyche: extermination of di weak and survival of di fittest."" Jordan-based jihadist cleric Abu Qatada al-Filistini, wey dem deport from di UK in 2013,tok di same thing for March. He stok say di UK response to Covid-19, dem design am to remove old pipo for di kontri to reduce financial pressures for di economy. Dis arguments follow wetin jihadist dey tok about Western capitalist system say e dey materialistic and e dey carry di economy and financial strength over human life and dignity. So far, di most direct call to use di Covid-19 pandemic in order to increase jihadist attacks globally don come from IS. For di editorial of al-Naba on 19 March, di jihadist group tell im followers say Western armies and security forces don dey ""stretched to di maximum"" for di support of their goment' efforts to stop di spread of di virus. Sake of dis, their capacity to constrain in their ability to fight jihadists abroad sake of di fear of infection, e add am. Data on attacks wey IS don claim worldwide don show upward trend for April and May over di first three months of di year. Dis conditions, IS tok say e dey, present golden opportunity for jihadists to strike even harder and ""show no mercy"". ""Di last thing dey [Western goments] need na new caliphate attacks wey be like di one for Paris, London and Brussels"", IS tok, as dem dey reference past attacks. Dem also tok say di rescue of ""Muslim"" prisoners while goments dey ""distracted"" suppose be priority. Dis na likely reference wey dem IS-linked prisoners and families wey dem hold for east Syria prisons and detention camps, among other jihadists wey dem detain for oda places. Di group also dey hopeful say di impact of di pandemic on goment' economies ""go need take big effect on how to weaken their ability to fight di mujahidin for di coming phase"". One week earlier, on 12 March, many international media outlets interpret IS general health guidance to Muslims to stay away from di epicentres of any virus outbreak to mean say na directive to its militants to avoid travelling to Europe. But dis no be wetin IS really tok, and a directive to members di following week confam di opposite; as dem tell followers to carry out attacks for Europe and elsewhere. (See: Explainer: Did IS ban members from going to Europe over coronavirus?) Shortly after IS call for attacks during Covid-19, pro-IS media groups produce posters wey dey call for attacks for di West. Images show landmarks for di UK and US with calls to ""Hit dem wen dey least expect it"" and di hashtag ""coronavirus"". In di same vein, on 25 March, di jihadist magazine Voice of India, wey dem link to di pro-IS Kashmir Jundul Khilafah, ask jihadists to use di pandemic as opportunity to strike for India and elsewhere. ""Allah don make dis disease a source of chaos among di nations of disbelief, and dem don deploy their militaries and police for their streets and alleys, E go make dem easy target... Use dis opportunity to strike dem"", di English-language publication tok. Al-Qaeda's soft message to Western nations during di global pandemic dey different from dat of im rival, IS. On 31 March al-Qaeda release im first official comment on di health crisis for one detailed five-page statement. Under di subhead, ""One general invitation to Western nations to enter Islam"", al-Qaeda ask dem to consider di moral and divine lessons of di coronavirus and how it don make strong economies, armies and goment dey ""helpless"". For one message to non-Muslims in general and Western nations especially, al-Qaeda tok say: ""We go like to express our strong desire for you [non-Muslims] to become our partners for heaven... Just as we share life on dis earth. na our desire and wish that we go all share eternal life for heaven. Therefore, we go invite you to get to know Islam and convert to am"". Inside di meassage, e tell dem to take advantage of di lockdown to read and learn about Islam ""through ogbonge sources wey dem fit trust"". Al-Qaeda promot Islam as a religion wey dey encourage cleanliness and personal hygiene, including through regular ablution to perform prayers and quote Prophet Muhammad say im dey encourage strict quarantine measures at times of virus outbreaks. Despite im conciliatory message to Western nations, al-Qaeda dey happy at di ""helplessness"" of Western goments, especially di US, to contain di pandemic and deal with di result di pandemic dey get on their economies. Al-Qaeda tok say di ""injustice"" and ""tyranny"" of Western governments get link to ""God's wrath"" wey don send coronavirus to dem. Di difference responses from al-Qaeda and IS to di pandemic dey represent di approach of individuals for di group and media strategies. While al-Qaeda dey use 'hearts-and-minds' policy to win over ordinary Muslims and sometimes Western nations IS dey use blunt, confrontational and uncompromising approach. Al-Qaeda's strategy, still never stop am to dey threaten and incite against both di US and im Western allies. Some jihadist groups or individuals don consider Covid-19 to offer temporary relief for jihadists, according to them, dem use di impact e get on reducing military operations against them as example. IS, for example, don report di impact of Covid-19 on di deployment of Western armies for di Middle East, especially Iraq, and for Africa Sahel. In April and May, IS attacks for Iraq increase. E no dey clear if dis na result of how di goment dey busy with Covid-19 measures or di ongoing political kasala for di kontri, plus how US comot operations against IS for Iraq. For early March, Syria-focused jihadist magazine say di global pandemic don ""slow down"" di war for northern Syria in favour of rebel and jihadist groups as e change di priorities of tdi Syrian goment and Russia wey don dey close to capturing Idlib Province. For April, Al-Qaeda's Sahel branch Jamaat Nusrat al-Islam wal-Muslimin (JNIM) bin happy say di ""Godsent"" don get impact on foreign troops wey dey fight jihadists for di African region. JNIM claim say di spread of di virus for France and Spain - both members of an anti-jihadist coalition for di Sahel - and purported infections among ""invader forces"" in Mali, dey make foreign troops to reduce or suspend operations for di region. Also for April, senior al-Shabab preacher, Fuad Shongole, tok am for one audio message say di pandemic dey work in favour of jihadists. Shongole, wey get bounty on im head, tok: ""dey [US] deny us movement and put five million on our heads. You don see plane dey fly nowadays?"", im dey suggest say dei number of US aircraft wey dey target jihadists don reduce. You go hear di congregation dey shout ""God is Great"". Most hardline jihadist groups wey don talk about their own militants taking precautions to avoid infections, and dem no show say di virus get any effect on their gatherings or operations. IS, for example, for May release some photo wey no too dey clear of im militants dey enjoy Ramadan food and dem dey pray together without any signs of social distancing. For April, Boko Haram leader Shekau compare di position of im fighters with all di Muslims around di world wey dey face restrictions like di suspension of di Umrah pilgrimage to Mecca, di closure of mosques or bans on Friday prayers. ""We dey fine, fine, fine"", he tok. ""We still dey able to pray five times everyday, we still dey fast, we dey flog pipo wey commit adultery and we still dey cut di hands of pipo wey tiff as punishment"", he add am. But jihadist groups, including IS and al-Shabab, don issue guidance to Muslims dey tell them to observe health and safety measures suitable for virus outbreaks. Most of the things dem recommend na from religious books and health advice from early Islam. Jihadists in general don criticise di moves to close mosques or stop communal prayers. Dem don argue say make Muslims take precautions, plus make dem wear masks and stay away if dem no well, but dem tok say make mosques no close their doors. Sake of active measures to take tackle di virus, some groups don prepare pass di others. Dis na especially di case for groups wey don hold territory. On 13 May, al-Shabab announce say dem form one seven-member committee to monitor Covid-19 cases for areas under im control and to provide guidance on future developments. Dem tok say di pipo wey dey di committee na doctors, religious scholars and sabi pipo. Di Syria-based opposition body, di Salvation Goment, wey dey run most of Idlib Province for di north, don dey very active as e dey try to prove say im be one de facto government. Na jihadist group Hayat Tahrir al-Sham (HTS) dey support di administrative body and na dem dey control di large parts of Idlib. Di Salvation Goment don dey promote im measures to curb di spread of di virus for Idlib. Part of im measures na to suspend Friday prayers and close open markets, remove public benches, sanitise prisons conducting tests, dem dey produce affordable face masks and dem also train female volunteers wey get medical background. On 12 May, dem announce say dey set up ""crisis cell"" to deal with di pandemic. Meanwhile, di Afghan Taliban don comment on the ""dire"" conditions and di too much crowd wey dey for Afghan prisons, dem warn say dis fit dey ""catastrophic"" for di context of Covid-19. Dem don criticise Afghan and US authorities as well as human rights organisations say dem no gree address di mata. Overall, jihadists don cautiously welcome dis period of Covid-19, dem dey see am mostly as a problem for dia enemies. Gloating don be part of di key sentiments wey jihadists don express towards di West. Jihadists no too show concern about di conspiracies say di development and spread of di virus in labs, and largely believe na God punish ""infidels"" and, later, to help jihadists. As IS bin vocal about using di pandemic to step up attacks, other jihadist groups dem don make as dem see opportunity in di pandemic. Dem dey hopeful say e go reduce military pressure on dem as e go distract goments and armies. Di pandemic so far never get any notable impact on di activities of di militant, as we report am on 17 April." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52782460 +health Coronavirus: COVID-19 patient escape for Ghana jump wall take escape quarantine facility as kontri record 9 new cases "One COVID-19 patient for Ghana escape from quarantine facility for Tamale, Northern Ghana. De patient be one of eight Guinea nationals wey test positive for de virus few days ago. De Guinea nationals travel through Burkina Faso den Togo wey dem enter Ghana, but security officials pick dem up acting on intelligence. Northern Regional Minister, Salifu Saeed reveal say de 21 year old girl escape from de facility at dawn when everyone dey sleep, she lef all her belongings including en phone wey she escape. Mr Saeed explain say ""while everyone dey sleep at dawn she manage leave de facility wey she jump de wall go."" ""Dis development dey worry sake of she test positive for coronavirus…"" Salifu Saeed explain. Police dey on manhunt for de patient who dey on de run, officials dey talk residents make dem report any suspicious case to de police. Meanwhile, Ghana record 9 new cases today which push de total confirmed cases go 161, out of dis figure 5 people die wey and one more COVID-19 patient for Ghana recover fully as test results turn negative. 3 patients recover so far. Ghana Health Service discharge 49 coronavirus patients go house for home management. Two of de largest cities Accra den Kumasi also dey under partial lockdown for two weeks as art of govment plans to stop spread of de virus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52095626 +health Ghana dancing pallbearers go charge US dollars after Covid-19 internet fame "Dancing pallbearers for Ghana say after Covid-19 pandemic dem go start charge dollars for international burial gigs. Benjamin Aidoo, de group leader talk BBC Pidgin say although de rates for Ghana go remain de same, dem go begin charge international clients inside dollars. “Now I go viral, I dey everywhere when dem lit de ban wey de pandemic end, I go charge high…moving outside Ghana e go change into dollars” Mr Aidoo. De coronavirus pandemic shut down countries den economies bring de world to a standstill. Chaw govments around de world close dema borders, ban public gatherings, lockdown everybodi plus 'stay home' order to citizens in order to reduce spread of Covid-19. While millions of people across de world dey under lockdown, boredom dey set in which dey make some people step out to town, while others dey find entertainment online. De dancing pallbearers from Ghana who dey dance plus coffin on dema shoulder turn major source of entertainment den coronavirus sensitisation message de world over. Thousands of social media users create plenty internet memes plus de dancing pallbearers, de message behind de pallbearers meme be simple: ""stay home or dance plus us."" Chinese company start dey sell dancing pallbearer dolls or like $50 dollars den tins. De group say dem no make money yet on de viral videos but after de pandemic end, dem go work on dema brand so say money go flow. Now dem get manager and lawyer from Kenya to handle dema contracts to ensure say dem no go lose out on de internet fame dem get dis year." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52432631 +health Ghana Covid rules: Nurses, security officers, students, govment workers den others go take Covid-19 vaccination by force from 2022 "Ghana Health Service announce say starting January next year, dem go make Covid-19 vaccination compulsory give some citizens. Some of dis people dey include health workers, security officers, govment workers, commercial bus drivers den others go receive mandatory vaccination. Others wey go be affected be staff den students for secondary den tertiary and schools. According to Director-General for Ghana Health Service (GHS), Dr Patrick Kuma Aboagye, ""de Minister go make de effective date for that vaccination in January."" De mandatory vaccination however no dey affect just a section of de public, dem also dey target public places where masses dey gather like beaches, restaurants, nightclubs, stadia, govment offices den hospitals. Groups of people who dey find themselves for dis venues go also take de mandatory vaccination. Health Officials say dis be part of moves to prevent fourth wave of de virus, especially after de country record Omicron variant recently. Prez Akufo-Addo announce say de country take stock of 17.7 million Covid-19 vaccines during en public address to Ghanaians. He urge citizens to make dema body available for vaccination sake of that be one of de surest ways to fight de pandemic. De country roll out new travel guidelines from last week which dey make vaccination mandatory for the airports, particularly for Ghanaians wey no vaccinate. But dem go return foreigners who no do Covid test back to country of embarkation. Dem further place $3,500 fine on airlines wey go fly unvaccinated travellers or people who no take dema Covid-19 test at 72 hours before travel. Some Ghanaians reject dis new mandatory vaccination as human rights abuse but govment say dis be de way forward to stop fourth wave from happening." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59694440 +health Coronavirus: Queen Elizabeth give ogbonge speech about Covid-19 "Queen Elizabeth di ll don tell UK say ""we go succeed"" in di fight against di coronavirus pandemic, inside ogbonge message to di nation. Inside di speech, di Queen thank pipo say dem follow goment rules to stay home and praise those ""wey come together to help odas"". She also thank key workers, say ""every hour"" of work ""dey bring us closer to return to more normal times"". Dis wan dey come as di number of pipo wey don die from di virus for UK reach 4,934. ""While we don face challenge dem before, dis one dey different,"" di Queen tok. ""Dis time we join all nations across di globe for one tin, to use ogbonge science and our compassion to heal. We go succeed - and that success go belong to every one of us. ""Make we take comfort say while we fit still get to endure, better days go return: we go be with our friends again; we go be with our families again; we go meet again."" Di Queen, 93, also say di ""painful sense of separation from pipo loved ones"" say social distancing from pipo remind her of di experience children wey dem evacuate get during di Second World War. ""Now, as den, we know, deep down, say na di right thing to do,"" she tok. Di Queen say everybody wey dey follow di guidance to stay for house dey ""help to protect di vulnerable and dey help many families avoid di pain wey pipo wey don lose dia loved ones dey face"". Na di fifth time di Queen don give dis kain speech in her 68-year reign." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52177000 +health Covid-19 Vaccine: Fully vaccinated passengers wey wan enta Nigeria no need run test again Since COVID-19 pandemic start fo all over di world, contra put plenty measures on ground way go reduce di rate of infection from one pesin to anoda. Sake of say di virus dey wake well well from Pipo way dey travel from different parts of di world , Nigeria follow put those restrictions. As di virus don dey reduce oda kontri don remove some of di measures wey dam put in place. On 4 April, na im di revised travel protocol wey Nigeria goment bring take effect. Di presidential Steering Committee on COVID-19 release new guidelines for passengers wey dey travel enta Nigeria. Pipo wey wan travel outside Nigeria go try do dis tins Pipo wey don kolet full Vaccination for COVID-19 na di pipo wey don receive at least two doses of any of dis COVID-19 vaccines weeks before dia date of travel: Boss Mustapha wey be di chairman of di sterling committee say dem go still review dis protocol afta four weeks. https://www.bbc.com/pidgin/tori-60991142 +health Coronavirus - Virus: Two suspected cases for Ghana test negative "Test results two for suspected coronavirus cases for Ghana test negative, according to medical officials. Korle Bu Teaching Hospital quarantine di two men wey dem suspect of de virus. Head of Disease Surveillance at di Ghana Health Service, Dr Franklin Asiedu-Bekoe, tell BBC Pidgin say ""de results of de test prove say both of dem be negative."" ""We go like talk de public say make dem no fear sake of de virus no dey Ghana"" he add. Health officials say dem go continue to maintain preventive measures den ensure say de disease does no go enter de kontri. De two suspects who be men, report dema bodi to di emergency unit of Korle Bu Teaching Hospital for Accra on Wednesday dey complain of malaise, muscle pains and flu symptoms after one private hospital turn dem away sake of dema symptoms. De Argentine, leave Shanghai for Accra in January dis year while en Chinese counterpart lef en home country for Ghana around September 2019. Accra Secretary for Ghana Medical Association, Dr William Baah talk say de two patients dey inside isolated facility wey dem collect blood samples from them for further analysis. ""Dem develop symptoms which dey fit de case definition but e no dey mean say dem get [coronavirus] though"" Dr Baah reveal. Health officials say dem go take more samples from de two patients for testing on Thursday for Noguchi Memorial Institute for Medical Research (NMIMR), wey Ghana ministry of health give responsibility to screen suspected coronavirus cases." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51397280 +health Covid-19 travel: India dey red, Ghana, US dey amber on Lagos alert list for passengers "Lagos State don comot alert list for kontris based on how Covid-19 dey worry and wetin passengers need to sabi. Di alert list wey Nigeria biggest commercial city authories release dey three types: ""red, amber and green."" India, wey be di world second most populous, dey on di red list because dem get coronavirus variant wey start from di kontri. Amber colour na for kontris wey di variant enta from anoda place and Ghana d While green dey reserved for all oda kontris. Lagos state commissioner for health, Prof Akin Abayomi release dis informate inside press conference wey e do on 12 May. Dis dey come as Nigeria don begin enforce curfew and restrictions from Tuesday midnight 11 May. E dey part of wetin di federal goment call ""phase four"" of dia programme to reduce coronavirus spread. List like dis no be new tin and many kontris get am to epp passengers know di rules before dem travel. For instance, Nigeria dey inside UK amber list wey dem release last week. As di commercial capital of di kontri, Lagos dey see thousands of travellers land from abroad everyday. And dis fit be why di state decide to comot plans to counter wetin Prof Abayomi say na di incoming third wave of Covid-19. All in all, Lagos put 16 countries inside dia red and amber list: Different rules apply to passengers wey dey land Lagos based on which kontri dem from dey come. For instance passengers from 'red' kontries go isolate for 14 days even if dem test negative before departure, while those wey dey come from green kontries no get dis kain rule. Prof. Abayomi tear warning give passengers wey break di State Covid-19 quarantine rules and instructions. E say anybody wey break di ruke fit chop fine of N300,000 ($731) and even collect one year prison sentence join. Di city health commissioner cite section 11 of new rule from di Lagos State Coronavirus Pandemic law, 2021 Section 11 say di governor get right to quarantine anybodi or joinbodi until im feel say e dey safe for di order to dey lifted." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57056898 +health Covid-19 in 60 seconds: Fake news fact check ontop coronavirus Today we torchlight fake news palava during dis coronavirus and how to sabi am plus know wia to find correct news wey conconcern COVID-19. Afta you watch dis video, you fit find all di latest authentic tori wey concern coronavirus mata for BBC. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52660224 +health Omicron Variant: African nations wit new Omicron coronavirus variant "Omicron variant of coronavirus don dey known for at least 24 kontries around di world. Dis na according to World Health Organization latest update on di new coronavirus variant [Omicron]. India, Ghana, Saudi Arabia and di UAE dem among di latest kontries to confam dia first cases of Omicron as at Thursday 2 December, 2021. Oda kontries wey include UK, US and Germany don also get report of pipo wey dey infected with di new variant. For Africa, na di rainbow nation dey lead ontop number of cases of infection wit di new variant. Dr John Nkengasong, di head of African Union health watchdog dey call for moderation ontop di way di world dey react to di new coronavirus variant. Omicron variant first dey reported to World Health Organization (WHO) by South Africa a week ago. Four African kontries na im don record di Omicron variant of Coronavirus. Africa Center for Disease Control Weekly COVID-19 briefing on 2 December 2021 na im confam dis figure. Dr John Nkengasong wey be di Director of di Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC) tok dis one during im Thursday briefing. And di kontries include; Dr Angelique Coetzee, president of di South African Medical Association na im first alert South African authorities about dis new variant of coronavirus on 24 November, 2021. Lab tests come later confam say she dey right and WHO come tok say dis na variant of concern. Dr Coetzee explain say di tin start on 18 November, wit one patient wey feel tired and dey experience body aches for many days. ""E get small headache, e no really get sore throat, e describe am like itch, no cough, no loss of taste or smell,"" she tok. Dr Coetzee find out say dis symptoms dey unusual and decide to get quick test for im office. Presently, as at today 2 December 2021, health officials for South Africa say Omicron now don become dominant inside South Africa and dey push sharp increase in new infections. South Africa don record 11535 new infections in di last 24 hours. Dis number increase from 8500 cases recorded on Wednesday 1 December, 2021. 44 pipo die on Thursday 2 December alone, for di latest daily figures. Dis don bring di total to 89,915 deaths to date for inside di rainbow nation. On di 26, November 2021 Botswana Ministry of health and wellness issue one statement on di new covid-19 variant. Di ministry say dem detect di new virus from four foreign nationals wey enta Botswana on di 7th November 2021 on diplomatic mission. Four of dem test positive for Covid-19 on November 11 as dem dey prepare to return. Further genomic sequencing wey dem do on di samples confam di virus as B.1. 1. 529 on 24 November 2021. ""Although all di four cases don leave di kontri, contact tracing dey go on. ""All contacts wey di kontri don so far identify, no get covid-19 symptoms and don test negative for Covid-19,"" di ministry tok. Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) confam di first case of Omicron variant on Wednesday 1 December, 2021. Di oga for NCDC, Dr. Ifedayo Adetifa for statement say dem identify two cases of di Omicron variant from travellers wey enta Nigeria from South Africa within last week. Dr. Adetifa say dem detect di cases dem afta genomic sequencing wey dem cari out for NCDC National Reference Laboratory for Abuja. Di NCDC Director General explain say even though di two cases wey dem find out now no dey show any symptom, dem don start to attend to dem clinically. And dem don begin to do contact tracing, make arrangement to notify dia kontri of origin to also begin in kontri response. Ghana start dey explore contact tracing afta dem record first cases of Covid-19 Omicron variant on Thursday 2 December, 2021. Ghanaian detect di Omicron variant along di entry borders from pipo wey dey travel from Nigeria den South Africa. Director General for Ghana Health Service, Dr Kumah Aboagye say; ""Through di robust testing for Kotoka International Airport, Ghana detect di Omicron variant already wey dey come from Nigeria den South Africa."" Di minister say now e dey mandatory for all civil servants, including health workers, security personnel, and teachers, to collect vaccine against Covid-19. Dr Angelique Coetzee, president of di South African Medical Association, say so far patients wey dey infected wit di new omicron variant get very mild symptoms. Coetzee tell BBC earlier dis week say: ""We neva put anyone for hospital yet. I don speak to oda colleagues and di picture na di same. Na Dr Coetzee first alert South African authorities about dis new variant of coronavirus. Lab tests come later confam say she dey right and WHO come tok say dis na variant of concern. Di doctor explain say di tin start on 18 November, wit one patient wey feel tired and dey experience body aches for many days. ""E get small headache, e no really get sore throat, e describe am like itch, no cough, no loss of taste or smell,"" she tok. Dr Coetzee find out say dis symptoms dey unusual and decide to get quick test for im office. Di patient and oda family members test positive for covid and as di doctor explain, all of dem get ""very, very mild"" symptoms. Oda patients wit similar symptoms present demsef throughout di day. Dr Coetzee come decide to alert di Department of Health vaccine advisory committee because she sef dey on it. Na di nose and throat swabs wey dem dey do for di polymerase chain reaction (PCR) tests wey dem dey send go lab go determine weda you get coronavirus. Afta dat, e depend on di lab wey dem carry di samples go, some of dem dey wey get di technology wey go fit find weda wetin you get na Omicron variant or Delta variant. Howeva no be all labs get am. To test for di variant, di test go look for three genes wey connect to parts of di vaccine. Dem be, spike (S), nucleocapsid or inner area (N2) and envelope or outer shell (E). If dem detect di S gene, e mean say possibility dey say na Omicron so e og go for more testing. Na eight point six million pipo so far dey infected wit covid inside Africa, according to di African Centre for Disease Control. Dis na di total figure from wen di pandemic start until now wey e don get different variants. So far na about 223 thousand deaths dem don record inside di continent. Mauritius don enta fifth wave of di Coronavirus, Dr John Nkengasong, di head of African Union health watchdog, tok. E tok on Thursday say 26 African kontris don enta fouth wave of Covid 19 pandemic. South Africa, Morocco, Tunisia, Libya and Ethiopia na im get some of di high cases as per kontri by kontri level for di continent. A new hope now be say one company don get license to manufacture Johnson and Johnson vaccine for South Africa, Dr Nkengasong announce on Thursday. Dis go help fight di coronavirus spread. And e add say nowadays access to vaccines no be problem. Di Omicron variant get plenti different mutations wey human neva see before, and many wey dem don see. Large number of dem dey on di spike protein of di virus, wey be di target of most vaccines, and dat na di main concern. For standard tests, Omicron get wetin dem know as one ""S-gene dropout"" wey dey make tracking positive cases wey resemble di variant very easy. But no be all ""S-gene dropouts"" go end up be omicron - full genomic sequencing dey needed to be sure. Di World Health Organization (WHO) don warn say Omicron coronavirus variant fit cause high risk of infection rate around di world Di variant fit lead to serious consequences for some regions, WHO tok on Monday. ""Covid-19 neva finish wit us yet,"" dis na di warning from head of di organisation, Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus. Dr Ghebreyesus tok say scientists around di world dey work to discover if di new variant dey associated wit higher transmission, risk of reinfection and how e dey react to vaccines. E add say no deaths wey don dey linked to di new variant yet." https://www.bbc.com/pidgin/world-59509692 +politics Resignation: Buhari and oda presidents wey Nigerians don ask to resign since 1999 "Some Nigerians for social media dey use di hash tag ""#BuhariResign"" to discuss mata wey dey for di kontri senate as e concern di ability of di security palava pipo dey face. As pipo begin use di hash tag upandan, President Muhammadu Buhari call urgent National Security meeting on Thursday to meet wit di Vice President of di kontri, Ministers of Defence, Interior, Police oga dem. Di head of di kontri secret police DSS, and oda ogas of security agencies and some senior goment officials also join di meeting to quick find solution to insecurity issues wey dey trouble di kontri. Tori be say Senate Minority Leader Enyinnaya Abaribe on Wednesday ask President Muhammadu Buhari goment to resign sake of say di goment no gree tackle insecurity mata wey dey grow for di kontri. But President Buhari no be di first president since 1999 to face dis kain demand to resign For August 2002, di Nigeria House of Representatives ask di former president wey rule Nigeria as a civilian from May 1999 to May 2007 to resign within two weeks or dem go impeach am. Di motion wey 360 pipo from di lower chamber support dey accuse Obasanjo of corruption, say im dey incompetence, and im no dey follow di constitution, dem still accuse am say im no dey capable to rule di kontri. Afta two weeks di former president no gree resign. Im say na joke wey dem don cari go far. Part of di allegation wey dem nack am na say im no gree implement di budget wey dem pass for ova three years according to di appropriation law. OLusegun Obasanjo hand ova power to Umaru Musa Yar'Adua for 2007 afta general elections. Before im death for 2010, di former president bin face gbas-gbos from different activists group for di kontri as dem ask am to resign. Wen dem rush di 58-year old go hospital for 2009 wen im dey complain of chest pain, 56 pipo wey hold ogbonge position for Nigeria write statement say make im hand ova power to im deputy. Part of di pipo wey sign di petition na Ken Nnamani, former senate president, and Aminu Bello Masari, former speaker of di House Of Representatives.""E no ft run di kontri di way dem suppose run am,"" Annkio Briggs, one activist from di oil-producing Niger Delta region tok. Wen im die for 2010 afta im go receive treatment for chest pain for Saudi Arabia, im deputy, Goodluck Ebele Jonathan later become president. President Muhammadu Buhari as opposition for 2013 ask Goodluck Jonathan to resign ova insecurity issues for di kontri. E tok say di former president don fail to protect di lives and properties of pipo from Boko haram insurgents since im assume office. Protesters and groups also say make Jonathan resign ova im removal of fuel subsidies for January 2012. Afta five days of national protests and strikes, di former president bow to pressure to reduce pump price of petroleum to 97 naira per litre from 147 naira. For 2015, Jonathan lose im second term election to President Muhammadu Buhari." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51313420 +politics Elections Ghana: John Dumelo lost NDC Parliamentary election to NPP Lydia Alhassan for Ayawaso West Wuogon Constituency "NPP Lydia Alhassan win NDC John Dumelo for Ayawaso West Wuogon Constituency' This na de hottest parliamentary seat contest for de 2020 elections. ""Thank you God for an answered prayer. Thank you Ayawaso West Wuogon for this Victory. I take my scripture from Proverbs 21:31."" Dat be wetin Lydia Alhassan of NPP pos for tweet just before de EC declare her win. Her victory mean say de Ghana MP go now retain her seat for parliament to serve de people of Ayawaso West Wuogon Constituency for another term. LYDIA ALHASSAN (NPP) - 39,851 JOHN DUMELO (NDC) - 37,778 Hours after de results announcement, John Dumelo write to de Electoral Commission, demanding to for a recount. NPP's Lydia Alhassan earlier talk BBC Pidgin say she she be confident of 65 percent victory. Meanwhile, John Dumelo of de NDC also be confident of victory come December 7. However, shortly before de declaration of results Dumelo write for im official social media page on Tuesday early morning say: ""We still waiting for de Electoral commission to declare de final results. By de projection, I be in pole position to win when all de results dey verified by de EC.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-55226446 +politics Attack on Benue state governor: 'My security man hit one of di attackers as I run to safety' - Samuel Ortom Govnor of Benue State, Samuel Ortom don reveal say im security man bin shoot one of di gunmen wey attack am for am. Di govnor tok dis wan for one ogbonge interview wit tori pipo for Abuja. E say as im security pipo engage di attckers and im di run, di bullet di waka pass im ear fiam fiam non of di bullet touch am e further add say one of im security man tell am say e hit one of di jaguda boy dem and dat di villagers also confirm say di attackers dem bin run wit someone wey wound. Di govnor bin cry out to Nigerians on di 21st of March say armed gunmen attack am as e dey go inspect im farm for Tyo-mu along Makurdi-Gboko Road. Di govnor say im dey lucky say none of im pipo wey follow am die. Many Nigerians don react to dis recent attack on di govnor - even di president Muhammadu Buhari don order make dem investigate di mata Combined team of security pipo don enta di farm and dem don clear some of di makeshift tent for di area Operation Commander of Operation Whirl Stroke, Major - Gen. Adeyemi Yekini, tell local tori pipo say dem don catch some pipo and dem di ask dem questions. But di govnor say di arrest of di three fishermen shock am as those wey attack am no be fishermen but na Fulani Herdsmen. Di govnor say for di kontri to solve di security palava for di kontri, e gatz embrace restructuring. For sometime now different group and region don di agitate for di restructuring of di kontri as dem believe say di recent political and governance structure for di kontri no dey work again. Di govnor say dis na di time wey all stakeholder for Nigeria business gatz sidon and look at which political system dey okay for di growth and development of di kontri. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56518035 +politics Governor Wike on Fani-Kayode defection, im advise to Goodluck Jonathan on next move plus reaction to oda national issues "Rivers state Govnor, Nyesom Wike say im and di former Aviation minister Femi Fani-Kayode wey just defect from di opposition Peoples Democratic Party, PDP to di ruling All Progressives Congress, APC, no be friends. Di govnor tok for inside exclusive interview with BBC Pidgin where im bin dey react to di defection say di former minister no be pesin wey even bin dey useful for di PDP before. ""I no know why pipo dey say e dey shock dem, you see no be everybody wey dey tok you go take imtok, some pipo dey tok so dem go find dem something to chop, some na so make dem save dem from problem wey dem get dats if at all dem go be saved. Me and Femi no be friends, im say one of di govnors wey e dey reach, na Rivers state, e know say e no go fit reach me, we no dey gel, e no go work, I no dey like artificial tins, me and Femi no dey tok. ""Femi wey dey tok, e come from Osun , which day e win Osun, no be im be spokesman for Jonathan campaign, wetin e don help PDP do?"" Wike tok. On di rumour of di defection of di former president of Nigeria, Goodluck Jonathan, Govnor Wike say if e get chance, e go advise am not to tink am. ""If I see di former president I go ask am say, oga wetin I hear? Make you no go anywhere oh, dis pipo wan spoil di remaining reputation wey you get. Dis pipo no like you, you suppose know dem well-well. Dem no like you. Wetin dis pipo never do, wetin dem never tok about you, dat tin wey dem don tok e don change? Wetin APC dey do na to bring pipo from PDP wen dem bring dem, dem destroy dem so dem no get anywhere to go again. I respect di former president and I know say e be man of integrity. E no go just begin jump, if I get way to advise am I go tell am not make dat mistake, if e wan run fro president make e do am under PDP,"" Wike tok. On question of weda e get interest to run for 2023 as presidential candidate under di PDP, Govnor Wike say im first and main interest now na to build di party. Govnor Wike also chook mouth for di palava of di party former national chairman wey dem suspend, Uche Secondus, according to Wike, Secondus bin dey run di party enta ground so e follow for pipo wey tok say make dem remove am afta im ward suspend am and im happy with di decision. ""E get di time wey I deny say I no get hand, dem suspend am e no dey do well, dem suspend am e no dey do well and I happy as dem do so. E get di tim wey I tell you say my hand no dey, I no hide am I know and I support am becos e no dey do well, if we leave am dis party go die dats why I say as di ward remove am, state approve am."" Wike tok. Reacting to di recent murder of Dr Chike Akunyili, husband to di late Director-General of di National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC, Wike blame federal goment on di issue of insecurity, say dem never take am seriously. ""Di kain of insecurity in Nigeria don too much, no day you go wake up wey you no hear say pesin don die, not death pertaining to sickness but dem kill am like say no security, wetin I go blame Anambra state govnor for? Govnors dey try to see how dem go fit put security but sometimes di federal government dey sabotage dem just like me wey dem sabotage well-well."" On di issue of di recent controversy around who suppose collect di Value Added Tax, VAT, between di state and federal goment, di govnor respond to statement of di northern govnor's forum wey say e move to challenge di legality of dat issue for court go lead to confusion and multiple taxation. ""Wetin dem dey call multiple taxation, na dem go dey dia dey interpret, na me put di tin for law, di issue I dey tell dem be say make una tok true, di tin wey I tok no be wetin di law tok? So if we agree say di tin I tok na true, den make we tok say ok you no say if you dey do am e go bring multiple taxation dat wan na anoda second arm of it, how e go take bring multiple taxation, den we go fit siddon say you wey you know how to correct am wey no go cos multiple taxation oya come siddon do am, no be to tell me say e go cos multiple taxation."" Di govnor fire back. Click here to watch di full longer version of di video." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58761997 +politics How former Oyo attorney general become deputy govnor afta lawmakers impeach di sitting one Oyo State Assembly for south west Nigeria, welcome im new Deputy Govnor, Bayo Lawal afta dem impeach di sitting deputy govnor on Monday. Rauf Olaniyan chop impeachment on top allegation of gross misconduct. To impeach a sitting govnor for Nigeria na very serious mata not just becos dem dey sack  di number two man for di state, but sake of say e mean di state assembly change di decision of majority of di pipo wey vote am enta office. Di circumstance of impeachment of Olaniyan raise questions on di constitutional position of di action of di State Assembly, considering say di deputy govnor and di govnor enta office based on joint ticket. Wetin go make a State Assembly to impeach di number two man for di state but leave govnor wey dem two dey share one ticket? Wetin be di position of di constitution on dis mata? To understand how mata take reach impeachment, e dey important to understand di back tori. Di mata between di sacked deputy govnor Rauf Olaniyan and di Govnor, Seyi Makinde according to political analyst Festus Adedayo be like wen two drivers dey drive di same car. Dis gbas gbos relationship dey traced back to di kontri 2019 general elections. For di 2019 elections, Olaniyan bin be di govnorship candidate for di African Democratic Congress (ADC), while Makinde bin be govnorship for di Peoples Democratic Party (PDP). To ensure say dem win Oyo state, di two men form alliance wey lead to Olaniyan becoming deputy govnor to Makinde for PDP. Dis alliance according to Oga Adedayo lead to “a situation wia you get two drivers inside di same motor, wey claim say dem sabi how to drive di motor pass and wey also desire to drive di motor.” Im say, “dis na two pipo wey bin dey interested for di same position, definitely gbas gbos go dey between di two of dem, an e actually happun for dia governing of Oyo state. Eventually dem accuse am feferising wit di opposition party.” For 5 June 2022, di den deputy govnor, Olaniyan, dump PDP port go di ruling All Progressive Congress (APC) party. For im porting speech im bin say: “Dis be joint ticket. Dem promise me many tins. No be about money. If to say na about am, I for no attempt to join politics. I no dey uncomfortable but as per say I dey position of power, you get right to assist many pipo.” For dia response to Olaniyan porting, PDP for di state release statement wey im Publicity Secretary, Akkem Olatunji sign, say make di deputy govnor resign honourably as im no fit go join di opposition party wit joint mandate wey im get wit Makinde. “Our position dey simple and very clear on dis mata, and as mata of legal implications, di vote of any election for Nigeria na to political parties and not candidates. Na on dis note PDP as di state ruling party dey advice di deputy govnor, Rauf Olaniyan, make im no dey carried away by lie.” Six weeks later di State Assembly impeach am. Di Oyo State Assembly begin moves to impeach Olaniyan based on five allegations of gross misconduct. For di petition wey dem title “Petition And Notice of Allegations of di Deputy Govnor of Oyo State, His Excellency Engineer Rauf Olaniyan,” di house members say dem raise di allegation based on Section 188 Nigeria Cosntitution amended 2011. Di misconducts wey 24 PDP lawmakers sign include, abuse of office, financial recklessness, abandonment of office and official duty and insubordination and oda offences. Due to di seriousness of impeaching a deputy govnor, Di Nigeria Constitution give eight steps wey any State Assembly must to follow to impeach am. Step 1: One third majority of di house must to sign written allegation of gross misconduct wey di deputy govnor committee den present am to di Speaker of di State House of Assembly. Di wahala be say di constitution no specify wetin gross misconduct be but define am as “… grave (very serious) breaking of di rules for dis constitution or di kain misconduct wey for di opinion of di National Assembly amount to gross misconduct.” Step 2: Speaker of di state assembly must to within 7 days, serve di deputy govnor plus each member of di State Assembly copy of di notice of allegation. Step 3: Di deputy govnor get di right to reply, although e fit decide say im no wan reply. And reply wey im give to di allegation, dem must to serve am to each member of di state assembly. Step 4: Within 14 days wey dem present di notice to di speaker of di state House of Assembly, di house go move motion without any debate on weda or not dem go investigate di allegation. At least two third majority of all members of di house need to pass di motion. Step 5:  If two third majority fail to pass di motion, den di process go immediately stop and no action again go fit happun. But if two third majority pass di motion, den within 7 days, di speaker go ask di chief judge to appoint panel of seven pipo wey im believe for im mind get correct integrity to investigate di allegation. Dis seven members no fit be members of any political party, public service or legislative house. Step 6: di panel must to give im report to di state assembly inside three months wey dem appoint am. During di proceeding, di deputy govnor get right to defend imsef and e get right to decide di lawyer wey go defend am. Step 7: If di panel report say dem no fit to prove di allegation, den no more action go occur. But if di report be say dem prove di allegation against di deputy govnor, den di state assembly go consider di report and pass resolution to adapt di report. Step 8: Before dem go fit adopt di resolution, notin less dan two third majority of all di members of di assembly must support am. Once dem adopt am, from di date wey dem adopt am, dem go remove di deputy govnor from office. https://www.bbc.com/pidgin/articles/crg7wn4mw79o +politics Biden Inauguration : How to watch US President-elect Joe Biden swearing in ceremony "Na just three days remain for di Inauguration ceremony of US President-elect Joe Biden and Vice- President elect Kamala Harris to take dia oath of office before Oga Biden go officially move to di White House. From Covid-19 protocols, to security concerns, to appearance from Lady Gaga, dis na eviritin you need to know about di big day. Di inauguration is na formal ceremony to marks di start of a new presidency, and e dey happun for Washington DC. Na di day wey di president-elect go recite di presidential oath of office: ""I do solemnly swear say I go faithfully execute di Office of President of di United States, and to work to di best of my ability, preserve, protect and defend di Constitution of di United States."" Once im use im mouth tok these words, Oga Biden go then take im place as di 46th president and di inauguration don complete (but dat no be all - celebrations go follow). Kamala Harris go become vice-president once she takes di oath of office, wey usually dey huppun just before swear in di president. By law, inauguration day na 20 January. Di Opening remarks go start 11:30 EST (16:30 GMT dat one na 5:30pm Nigerian time) and na midday dem go swear in Joe Biden and Kamala Harris. Cable company DSTV go show di Inauguration live for BBC and CNN for Nigeria. BBC channel 400 and CNN channel 401. Afta di inauguration finish Oga Biden go move go White House later in di day - wey go be im home for di next four years. In recent years, incoming presidents dey invite some ogbonge musician for di kontri. Even wit di pandemic, dis year own no go dey different. Oga Biden and Madam Harris go dey joined by Lady Gaga - wey be strong supporter of di incoming president she even campaigned wit am sef days before di election. Lady Gaga go sing di national anthem and Jennifer Lopez go sing during di ceremony musical performance. Afta dem swear Oga Biden, actor Tom Hanks go host 90-minutes of primetime television - na Covid-friendly replacement of celebrations typically before pipo for attend. E go feature Jon Bon Jovi, Demi Lovato and Justin Timberlake and dem go broadcast across all major US networks and streaming platforms - apart from Fox News, wey be conservative network wey primarily support Oga Trump during im presidency. Na custom for di outgoing president to watch as dem swear in di next in line, wey fit make things look awkward. Dis year, di outgoing president no go show face for dia. ""For those of una wey dey ask, I no dey go di Inauguration on January 20th,"" Oga Trump tweet dis one on 8 January. It comes shortly afta di president tok say e dey committed to an ""orderly"" transition of power to a ""new administration"" - na di closest him don tok publicly to conceding di race to Oga Biden. Some of im supporters don already take am to anoda level sef, dem dey plan virtual ""second inauguration"" for Oga Trump di same day (and time) wey Oga Biden dey take office. More than 68,000 pipo tok on Facebook say dem go attend di online event to show their support for OgaTrump. But Vice-president Mike Pence, don tok say e go attend. When dem swear in Oga Trump, Hillary Clinton bin join her husband, former President Bill Clinton, for di inauguration - just two months afta her election defeat and bitter campaign against Oga Trump. Only three presidents - John Adams, John Quincy Adams and Andrew Johnson - na im don bone dia successor inaugurations, and none for di last century. Presidential inaugurations typically involve ogbonge security plans, not to tok of now, afta Trump supporters burst enta US Capitol on 6 January. Di FBI don warn of armed protests for di state capitols across di US and for Washington DC for di days leading up to di inauguration, wey make officials to step up security and close off large sections of di city. Rehearsal for di ceremony wey suppose happun on Sunday dem postpon am due to security concerns, tori be say dem reschedule am to Monday." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55693912 +politics Osun APC primary election result: APC declare Adegboyega Oyetola winner of Osun state governorship primary "Osun state governor, Adegboyega Oyetola, don dey declared as di winner of di governorship primary of di All Progressives Congress wey hold on Saturday. Kwara state governor, Abdulrahman Abdulrazaq, wey also be di chairman of di committee wey conduct di primary na im announce di result of di exercise. Oyetola win di election, as im get 222,169, against 12,921 wey im closest challenger, Moshood Adeoti get. Mr Lasun Yusuf score 460 votes and finish third. According to Abdulrazaq, na total of 408,697 voters register to vote for di primary election of di party. For im remark, Osun State APC chairman, Gboyega Famoodun, commend di committee, security agencies and others wey work for di success of di exercise. Before Sunday announcement of di final result, supporters of oda candidates bin don allege say di Saturday party primary bin experience wuru-wuru. Missing names, non availability of result sheet na some of di complaints wey dem raise about di primary wey hold across 332 wards for di state. For instance, dem allege say Ward 1, 7 and 9 of Oriade Local Government of di State no suppose get result as di process bin no pure. According to one APC member for Ward 1, Erin-Oke, Yinusa Adeyeye, di returning officers come di collation centre around 1pm and start to rush pipo to vote. Adeyeye say di APC members wey don dey wait for accreditation since 8am, come vex and ask di returning officer to do accreditation before voting. Di returning officer according to reports say im bin come late and so e no fit do any accreditation. According to him, commotion brake out wen Oyetola supporters attempt to go ahead wit di election without accreditation, move wey Adeoti supporters reject. But Osun state governor, Oyetola, bin praise di turnout of members of di All Progressives Congress during di governorship primary. Oyetola, bin speak for Iragbiji, after im vote during di exercise. Im call on di pipo to maintain peace. Im say make dem no turn di election to battle field, as im ask for no violence. ""I want to appeal to all our people all over di state to please maintain peace. Dis election process no suppose be battle field. E no suppose be do or die affair. Violence no suppose dey. Let everybody get di opportunity of participating in his choice of who should be di candidate of our party,"" Oyetola bin tok wen voting bin dey go on. ""I think dat na di process and I think e don on very well contrary to di speculation."" Similarly, many supporters of di governor don commend di exercise, as dem say di primary bin dey free and fair." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60451377 +politics 'Trump Organization dey guilty of tax crimes' "Jury for New York don find former US President Donald Trump family real estate company guilty of tax crimes. Dem convict Trump Organisation on all counts on Tuesday afta two days of injury deliberation for New York. Di business dey closely associated wit di former president but Oga Trump and im family members no dey personally on trial. Dem convict di company of enriching dia top executives wit off-di-books benefits for more dan ten years. Some Untax benefits include luxury cars and private school fees, prosecutors tok. Dem say dis make up for lower salaries and reduce di amount of tax di business dey required to pay. Di company dey expected to face fine of around $1.6m (£1.3m) and dem fit face difficulty in securing loans and financing for di future. Oga Trump previously criticise di trial say e dey politically motivated. E also attack im long-serving former chief financial executive Allen Weisselberg afta im plead guilty for August and testify against di business. For im most recent statement, di former Republican leader ask why di Trump Organisation suppose dey prosecuted for Oga Weisselberg's ""personal conduct"" - and im accuse di man of ""committing tax fraud on im personal tax returns"". ""We bin rely on a den highly respected and expensive accounting firm, and law firm, to do dia work,"" Oga Trump for one statement wey im office issue. ""Dis case dey unprecedented and... na continuation of di Greatest Political Witch Hunt for di History of our kontri,"" e tok, and im add say New York City don become ""hard place to be a Trump"". Prosecutors accuse di Trump Organization - wey dey operate hotel, golf courses and oda properties around di world say dem get ""culture of fraud and deception"" during di six-week trial. Dem say dem run scheme wey allow some executives to “under declare dia compensation” so dia taxes “go dey significantly small dan di amounts dem suppose pay”. “Di smorgasbord of benefits dey designed to keep dia top executives happy and loyal”, prosecutor Joshua Steinglass tell di jury during closing arguments. Two subsidiaries of di Trump Organisation - Trump Corp and Trump Payroll Corp - dey convicted on all 17 charges of tax fraud and falsifying business records. Manhattan District Attorney Alvin Bragg praise di verdict on Tuesday and say di case na ""about greed and cheating"". ""For 13 years, di Trump Corporation and di Trump Payroll Corporation get away wit a scheme wey award high-level executives wit big benefits and compensation while dem intentionally hide di benefits from di tax authorities,” e tok. Oga Weisselberg, 75, testify against di company as part of a plea deal im strike wit prosecutors wey go mean say e spend notin more dan five months for jail. E go spend time for jail for di notorious Rikers Island prison and gazz pay back more dan $1.7m (£1.4m) income e hide. Afta di verdict, di judge set a sentencing date for 13 January. Oga Trump and im three eldest pikin dey face separate civil lawsuit wey fit see say dem ban dem from doing business for di state. New York Attorney General Letitia James wey dey lead dat civil case issue one statement wia im hail Tuesday verdict as “big victory”. ""[E] show say we go hold individuals and organisations accountable wen dem violate our laws to line dia pockets,"" she tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c6p9rxv3wedo +politics Four things wey go affect Nigerians inside President Muhammadu Buhari Christmas message "Nigeria president, Muhamadu Buhari don felicitate wit all Nigerians, most especially Christians, on di occasion of Christmas 2020. For inside statement wey di presidency release of Friday 25 December ,President Buhari recognise di different challenges wey di kontri dey face in recent time. E tok about di rising spate of armed banditry, kidnappings, insurgency, economic recession and di increase of COVID-19 infections. Wetin di president tok? ""Under my watch, di Federal Government go kontinu to provide di needed support based on resources wey dey ground to di gallant members of our armed forces and security agencies as dem dey deal wit threats to our citizens."" Im ask security agencies to do more to checkmate di rise of insecurity especially for di northern parts of di kontri plus di entire nation. E say im goment go remain focused on following di ""complex, multi-dimensional route"" to reduce di incidents of insecurity for di kontri to di barest minimum. ""Our pipo must dey free to live and move witout hindrance."" E follow throway twale give di military on dia work on di release di abducted schoolboys of Government Science Secondary School, Kankara, ""For me, providing security for all residents for di kontri remain an article of faith."" President Buhari say im dey hopeful say di kontri suppose comot from recession kia kia. As e follow gree say true true economic hardship knack kontri sake of di pandemic. ""We go do everything possible to fully implement di 2021 Budget of Economic Recovery and Resilience."" As di kontri dey experience di second wave of COVID-19 infection, President Buhari ask all citizens and resident to follow di safety guidelines wey authorities don put for ground as pipo dey celebrate Christmas wit families and friends- regular hand-washing, wearing masks and social/physical distancing. ""As national and state institutions dey try dia best, we must take individual responsibility and resist di strong temptation not to follow di recommended protocols from Presidential Task Force on COVID-19 and beat di pandemic."" he tok. President Buhari say im administration go deliberately target di youths so dat dem no go fall into di trap of unpatriotic elements wey wan cause kata kata for di kontri wey dey lead to avoidable loss of lives and property E say even as di right to peaceful association and protest dey guaranteed under di laws, im administration no go fold hand to watch protests even if e get good intention to turn to killi killi of security personnel or destruction of private and national assets." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55447407 +politics Edo election update: Ize Iyamu don win di APC govnorship primaries for Edo state Pastor Osagie Ize-Iyamu don become di govenorship candidate of di ruling APC party for Edo State, South-South of Nigeria Ize-Iyamu win di governorship primaries wey dem do through direct election afta two out of di three contestants withdraw dia ticket before di election start. E dey likely say Oga Iyamu go face di sitting governor of di state, Godwin Obaseki for di next elections, if Obaseki gbab di governorship ticket of di opposition party, People's Democratic Party. In di past months gbas-gbos don dey happun for di state after di APC deny Godwin Obaseki ticket to run for anoda term under di party before im port go join di opposition party. Di question now na if Ize-Iyamu fit stand against di sitting governor of di State to be di next govenor of Edo State. Ize Iyamu na di former chief of staff and secretary to di Edo state government from 1999 to 2003 Im be di govnorship candidate of di Edo state People's Democratic Party for di 2016 Edo state gubernatorial election. Im be former National vice-chairman, South-South Zone of di defunct Action Congress of Nigeria. Ize-Iyamu bin don serve as di Director General of di former govnor of Edo State, Adams Oshiomhole second term Campaign Organisation wen di former govnor win massive landslide for 2012 govnorship election for Edo State. Oga Ize-Iyamu also bin act as di Coordinator of Goodluck/Sambo Campaign Organisation. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53138996 +politics Ivory Coast election: President Ouattara call for protest to end, Opposition demand 'civil transition' "Opposition leaders for Ivory Coast dey demand for wetin dem call ""civil transition"", after Saturday presidential poll wey dia party bin boycott. Pascal Affi N'Guessan and Henri Konan Bédié tok say e dey illegal for President Ouattara to stand for third term as e go against di number of terms di law allow. Meanwhile, vote counting don begin. ""Opposition parties and political groups call for di start of civil transition,"" Oga N'Guessan tok on Sunday. ""[We] believe di end of President Alassane Ouattara mandate happun on 31 October and we call on di international community to take note,"" e tok, and im continue say civil transition dey needed to ""create di conditions for fair, transparent and inclusive election."" At least 16 pipo don die since riots begin for August when President Alassane Ouattara tok say e go run again after di sudden death of di pesin im prefer to take over. At least two pipo na im dem kill during Saturday elections. Many polling stations for areas wey opposition strong na im see katakata as some election materials burn. For di eastern town of Daoukro, protesters erect roadblocks. Meanwhile tear gas na im authorities use chase I-no-go-gree pipo wey gada wia di president wan cast im vote for di main city, Abidjan. At least two observers from di independent election group Indigo Côte d'Ivoire na im dem attack, di Washington Post bin report. Di group torchlight say 21% of polling stations no even open during di day. But di electoral commission oga say di gbege wey happun on Saturday dey ""small"", say na ""only 50 polling stations out of 22,381 e affect"". After e vote for Abidjan on Saturday, Oga Ouattara call for end to di protests. ""They should stop because Ivory Coast need peace, di na criminal actions and we hope say di go all stop, so that after di election dis country fit continue to get progress, wey e don enjoy for di last few years.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-54765043 +politics Democracy Day in Nigeria 2020: See di female politicians wey still dey struggle to break record since June 12 in Nigeria "Since Nigeria gain democracy for 1999, plenty arguments still dey about gender imbalance for di political space. Women don cry say marginalisation still dey happun wen e come to getting political appointments or getting electoral positions, but many of dem still dey determined to hold dia ground and make a name for themselves. Who be di women wey dey shake Nigeria political space? Stella Oduah na 58 year old Nigerian Senator and former Minister of Aviation. She bin dey active for di political campaign of former President Goodluck Jonathan for 2010, na she serve as di campaign Director of Administration and Finance. For 2015, dem elect Stella to di Nigerian Senate to represent Anambra North Senatorial District. She be one of di only seven women wey dem elect to di 8th national assembly AT DI TIME. Oduah get re-election to a second term for di Senate in 2019 and she is still serving till date. Aisha Jummai Al-Hassan AKA Mama Taraba, na 61 year old Nigerian lawyer wey be di first woman to be appointed asTaraba State Attorney General and Commissioner of Justice. Her political stronghold make am di first woman to get appointment as di Secretary FCT judicial council and later appointed di Chief Registrar of di High Court of di Federal Capital Territory, For 2011, with 114,131 votes, di pipo of Taraba North elect Aisha to represent dia constituency for di senate, under di Peoples Democratic Party ticket. She dey one of di four women wey dem elect under di PDP ticket for di senate dat year. Alhassan contest di 2015 governorship elections to be di 10th Governor of Taraba State under di Platform of di All Progressive Congress (APC) but she later lose di seat to Darius Ishaku For November 2015, dem declare am winner of di April 2015 Taraba state gubernatorial election, and she become di first woman for Nigeria to become a Governor. Di court of appeal later reverse am sake of political party gbas-gbos. She later become Minister of Women Affairs for di same year under di Buhari administration before she resign for 2008 to decamp to United Democratic Party ,UDP, sake of say di All Progressive Congress disqualify her to run for Governorship election again for Taraba State. After she lose di governorship election, she decamp to di Peoples Democratic Party, PDP. Dem sabi am well ""Mama Taraba"", sake of her increased influence for di politics of her state. Abike Dabiri-Erewa na 58 year old Nigerian political wey dey currently serve as di Chairman of Nigerians in Diaspora Commission. She be former member of di Nigeria Federal House of Representatives dey represent Ikorodu Constituency for Lagos State. She be di Chairman of di House Committee on Media & Publicity. As a former Chairman House Committee on Diaspora Affairs, dem elect her for di first time for 2003, and re-elect am in 2007 and 2011. Abike Dabiri bin gain popularity from journalism wen she work for Nigeria Television Authority where she dey anchor di weekly NTA Newsline programme with particular interest in poverty and social justice issues. Wen Abike Abiri bin serve for di House of Reps, she sponsor a number of ogbonge bills wey di Parliament pass, Abike Dabiri' s role as di Chairman of Nigerians in Diaspora don put am for international limelight and her name dey always surface for news as one of di ogbonge politicains wey don lend dia voice of change for di Nigeria political space. 71 years old Ambassador Kema Chikwe na woman wey her drive for inclusion and results don make am get get ogbonge career opportunities for Nigeria. She don successfully hold positions as di Minister for Transport, for Aviation and Chairman of di Joint Admissions and Matriculations Board (JAMB) Amb. Chikwe currently hold di office of di National Woman Leader of Nigerian political party Peoples Democratic Party .wia she don create opportunities for other young women to achieve dia career and political ambitions. For 2016, Di Peoples Democratic Party name Kema Chikwe, as one of di nine founding mothers of di party. Dem appoint am as Minister of Transport for June 1999 - 2001 and then of Aviation by President Olusegun Obasanjo from 2001 until May 2003. Kema Chikwe brace herself up for di big race wen she run for governorship election for Imo State. ""My boldest move na to contest for Governor of Imo State, Nigeria. na me be di only woman wey dey campaign in an era where di mindsets of pipo neva readi for a female Governor."" she tell tori pipo for sheleadsafrica magazine For 2009 she become Nigerian ambassador to Ireland. Wen you dey talk about women involvement in politics for Nigeria, Kema Chike name dey always surface for di top of di list sake of di ogbonge role wey she dey play for her political party. Oby Ezekwesili, na 57 year old Nigerian chartered accountant and politician. She be di co-founder of Transparency International. She be one of di pioneer directors of di global anti-corruption body wey base for Berlin, Germany. She serve as Federal Minister of Solid Minerals and later as Federal Minister of Education during di second-term presidency of Olusegun Obasanjo between 2003-2007 After di termination of her appointment she become di Vice-President of di World Bank, Africa division from May 2007 to May 2012. Ezekwesili na 2018 nominee for di Nobel Peace Prize for her work for transparency for di extractive sector. Oby Ezekwesili champion di Bring Back Our Girls (BBOG) advocacy group to draw global attention to di plight of all di pipo wey terrorists don kidnap for Nigeria expecially di ova 200 school girls wey Boko Haram Islamic terrorist kidnap from dia hostel in 2014. Ezekwesili dey part of di pipo wey start di #BringBackOurGirls viral campaign on social media. Ezekwesili contested for di office of di president of Nigeria on di platform of di Allied Congress Party of Nigeria in 2019, but she later step down sake of di gbas-gbos wey happun within di party. She organised a World Press Conference wia she open up about her rough Political journey as she dey campaign for di office of di President of Nigeria under di political party of Allied Congress Party of Nigeria (ACPN). Even as plenti pipo dey disappointed say she comot from di presidential race, expectations still dey high say she go come back to change di face of politics in Nigeria. In recent times, Nigeria don see sharp increase in women participation in politics even though the kontri never get any female govnor or president but di determination of some of dis women seems to tend towards breaking di barriers. Gbemi Saraki na former Senator wey dem elect to represent Kwara central Senatorial district and she be also di sister of former Senate president, Bukola Saraki. She attend University of Sussex for United Kingdom and get bachelor degree in Economics. Pauline Tallen na Former deputy governor of Plateau State for 2007 and di first woman to be deputy governor for northern Nigeria. For 1999, she become di Minister of State for science and technology during di time of former president, Olusegun Obasanjo. She also don contest to be governor of plateau state for 2011, but lost to Jonah Jang." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53015337 +politics INEC Server: 'Na manual election we do for 2019' "Di Independent National Electoral Commission of Nigeria (INEC) say dem no store result of di 2019 general elections ontop computer server, because dem conduct di election in manual way. Tok-tok pesin for di commission Festus Okoye, tell BBC say need no dey for INEC to store information of result inside server because dem no transmit result electronically. ""Since dem no sign law wey no suppose allow us to transmit result electronic way, we decide to conduct di elections manually according to wetin di current law tok"" ""Di law tok say every aspect of our elections must be done manually,"" oga Okoye tok. Okoye tell BBC dis one in reaction to tori wey comot for local media say di lawyer wey dey represent INEC tok inside di case wey di Peoples Democratic Party presidential candidate Atiku Abubakar bring against di election office. When Atiku lawyers dem bin ask di court to order INEC make dem allow dem torchlight di server wey dem keep election result, INEC lawyer for di case tell di court say ""dem dey ask us to bring something wey we no get."" Dis make many Nigerians para ontop social media. Some say e no possible say INEC fit don conduct elections but no get server. Odas ask say wetin come happun to di big money wey di commission bin budget to buy server. Di total money wey INEC collect from di federal goment to take conduct di 2019 general elections na N189.2bn ($ 523m) Former President Atiku don always maintain say na im win di presidential elections and say if INEC gree im team to torchlight di election server, im go prove say dem change di numbers wey dem take declare Buhari winner. Di INEC representative say dem get sever for information wey relate to accreditation from card readers and di political party pipo dem get access to am. E no dey clear whether na dis same server wey suppose get collation data for voters ontop am." https://www.bbc.com/pidgin/tori-48637168 +politics Insecurity in Nigeria: 'Lagos security dey far better dan any oda part of Nigeria' - Lagos state goment "Fear to move for night dey catch many Lagosians wey dey live for di Nigeria commercial capital, as insecurity dey rise for di state. Once day don dark, many Lagosians dey move around town wit fear as traffic robbery and one-chance don become part of dia everyday life. Even though insecurity dey increase for Lagos, di state Chief Press Secretary, Gboyega Akosile, say compare to di level of insecurity wey dey for many different parts of Nigeria, security for Lagos still beta pass. ""Security for Lagos dey far far beta dan security for any oda part of Nigeria,"" im tok. Oga Akosile describe di security problem of Boko Haram, banditry and kidnapping wey dey worry for most parts of di kontri as di real insecurity palava wey Nigeria dey face, come add say, ""you no go say we get dis kain security situation for Lagos."" On April 27 and 28, United States, Canada, Australia and United Kingdom, bin send security warning plus travel advice give dia pipo for Lagos as dem add Lagos to di former safe cities watch list. Di alert bin even torchlight how di armed robbers dey attack pipo for road inside Lagos. But Oga Akosile for in reaction to di security advise say, kontris get right to advice dia pipo not to ""As far as Lagos state wey Babajide Sanwo-Olu dey govern dey concern, di security situation her dey good." https://www.bbc.com/pidgin/56949528 +politics D-Day for Bayelsa Elections Today na di D-day. Bayelsans for South-south, Nigeria, dey go polling station to elect di next governor of the state. Di days wey lead to di election don see heavy campaign especially between di ruling People's Democratic Party for di state and di main opposition, di All Progressives Congress, APC. Some katakata don happun during di campaign, di most recent on na di PDP campaign rally for Nembe local goment area wia at least two pipo die and many odas wunjure. Although di gbege kill di spirit of some pipo, many still dey determined to comot and vote for di elections. Di two main party wey dey contend for di governorship ticket - di PDP and APC - don enta same trouser for court wey di two of dem don collect court orders and stay of execution of judgement ontop whether dem go participate for di elections. According to di Independent National Electoral Commission INEC, na 867,088 registered voters dey Bayelsa State and 769,609 don collect dia permanent voter cards wey represent 83.35%. Sensitive and non-sensitive election materials don already reach di Registration Area Centres (RAC) for di 8 Local government areas for distribution to di different-different wards and polling units. More than 32,000 security personnel don dey on ground to make sure say di electoral process is peaceful, free and fair. Many pipo for Bayelsa take advantage of di public holiday wey Governor Seriake Dickson declare, to use travel home to di riverine towns and villages in preparations to vote di pesin dem believe say go move di state forward. Some Bayelsa pipo say infrastructure like good roads and bridges na di tins wey dem go use choose di govnor. For oda Bayelsa pipo, work for di youths in di state, improved and regular payment of salaries for civil servants and pensioners, provision of portable water and stable electricity to ginger SMEs, not to forget security na di issues wey dey di minds of indigenes. Dem create Bayelsa State from Rivers State on 1 October, 1996, wit 8 local government areas. Di 23-year-old state, na one of di youngest states for di country as many dey hope for beta development and say make e happun for dia lifetime. Previous Governors of di State include di Late Chief DSP Alamieyeseigha, former President Goodluck Jonathan, Chief Timipre Silva - di present Minister of State for Petroleum Resources and di present Governor, Henry Seriake Dickson. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50439434 +politics Rescue Nigeria Project: Prof. Attahiru Jega, Donald Duke, odas tear rubber movement and how e go work "Former oga for Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC, Professor Attahiru Jega alongside Professor Pat Utomi, former Govnors of Kwara Abdulfatah Ahmed and Cross River Donald Duke gather for Abuja to form di Rescue Nigeria Project. Di National co-ordinator of di project Mallam Usman Bugaje tell BBC Pidgin say, dia project no be political party but na movement wey go push political parties to do right tin wey go lead to good governance for Nigeria. Bugaje wey serve as adviser to former Vice President Atiku Abubakar also yan say no be 2023 dey dia mind as some reports don already begin tok but di 'future of Nigeria and 'good leadership' na im dem dey concerned about. ""We no go just siddon to dey continue to allow di kontri dey spoil dey go na why we come together to from Rescue Nigeria Project. Our aim na to push political parties to comot beta way wey leaders go dey come out instead of di present ways wey no dey pure and dey only give room for bad leadership. Wit di way our political parties dey at di moment, no way any beta leadership for di kontri go comot from dia dis na why we come together to save our kontri."" Dis na wetin di National co-ordinator yan. Bugaje say dem no dey target anybody or any group but dia own na for Nigeria to get beta leadership. On weda some of dem get political ambition, dis na wetin e tok. ""For now none of us don comot show any interest for any political office but if di time come we go discuss am."" For Nigeria, elections go hold in 2023 and INEC wey dey in charge of conducting elections for di kontri say dem go release timetable for November dis year. Nigerians dey expect say di major political parties na dem go still make waves for di next elections. Di All Progressive Congress (APC) na dem be ruling party for Nigeria and 2023 go make am eight years wey dem don rule di kontri. Di oda major party na di People's Democratic Party (PDP) wey lose power for 2015 after current president Muhammadu Buhari defeat den presido Goodluck Jonathan six years ago. For most Nigerians, di concern no be majorly about 2023 but na about leaders wey go make a difference for dia lives." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58648428 +politics Wetin Senator Ademola Adeleke first do within 24hrs as govnor of Osun "Wit less dan 24 hours since dem swear am in as di 6th govnor of Osun state Senator Ademola Adeleke don begin work straight and in name don dey ontop di lips of plenti pipo across di kontri. First of all, e announce di appointment of im chief of staff, di secretary to di state goment and im toktok pesin. On Monday, e enta di govnor office wey dey Abeere side of di state capital, Osogbo wia plenti civil servants comot to welcome am. E also e issue Six Executive Orders wey cover Chieftaincy matters, appointments, odas. For statement wey im newly apponited toktok pesin Olawale Rasheed sign, di executive orders wey cover chieftaincy matters, appointments issues, setting up of review panel, staff audit and employment matters go take immediate effect. Recall say during im inaugural speech on Sunday e bin give some directives about some tins wey im predecessor bin do for office after di July 17 election wey bring am to power. Oyetola dey contest di result of di election for di Tribunal wey dey siddon for di state high court. Before Oga Adeleke Inauguration on Sunday 27 November 2022, di Peoples Democratic Party for Osun bin tok say dem go cancel all di last minute appointment wey former govnor Oyetola make wen im want comot office. Executive Order on State bank accounts Immediately afta im swearing in, di govnor bin order make dem freeze all di state accounts for banks and for oda financial institutions wey di state moni dey before e come issue di executive order on Monday. ""I hereby order di immediate freezing of all goment accounts for all banks and oda financial institutions"". E bin declare. E establish one panel to carry out inventory and recover all goment assets. Executive Order Number 2 on Staff Audit Dis one read ""All Heads of Ministries, Departments, Agencies, Commissions, Boards and Parastatals for Osun State goment dey hereby directed to carry out one immediate staff audit of di actual number of goment workers for dia Ministries, Departments, Agencies, Commissions, Boards and Parastatals, as at 17th July, 202. And make dem file one report to di Office of di Chief of Staff to di Govnor. Make dem state di full details and position/designation of each of di staff for di forwarded list. Within seven working days from di date of dis Executive order and use di attached Oath of Fidelity Template"" dem add. Executive Order number 3 on Employment ""All employments in the service of Osun State Government made in any capacity into any capacity in all the Ministries, Departments, Agencies, Commissions , Boards and Parastatals after July 17th, 2022 be and are hereby nullified, govnor Adeleke tok. Local media report say di immediate goment bin employ at least 12,000 workers after di election and prior di inauguration of Govnor Adeleke. BBC Pidgin no fit confirm di number of employment. Executive Order 4 on Appointments ""All appointments for di service of Osun State Goment wey dem make for any capacity into any capacity for all di Ministries, Departments, Agencies, Commissions, Boards and Parastatals afta 17th July, 2022 be and hereby dey reversed. Some days to im hand over govnor Oyetola bin appoint 30 permanent secretaries to different ministries. Govnor Adeleke bin release one statement where e warn say any pesin wey collect di permanent Secretary appointment from di outgoing govnor go exit di service for 28th November State Governor-elect, Senator Ademola Adeleke. Dem swear dem in for 24th  November, 72 hours before di new govnor take seat. Executive Order number five on Chieftaincy Affairs and appointment of traditional rulers. Govnor Adeleke order make security agencies take over di palaces of di three new traditional rulers wey Oyetola appoint- dis include dat of di former state chairman of di APC, Gboyega Famoodun. ""All appointments of traditional rulers wey Osun State Goment bin make afta 17th July, 2022, dey hereby ordered to dey reviewed to make sure say strict compliance wit due process of chieftaincy declarations and native law, custom and tradition wey relate to dat kind chieftaincies. ''For di case of Ikirun, Iree and Igbajo, to avoid further breakdown of law and order, di appointments of Akinrun of Ikinrun, Aree of Ire and Owa of Igbajo don hereby put on hold pending review. Den, make di palaces of Akinrun of Ikirun, Aree of Iree and Owa of Igbajo remain unoccupied, while security agencies dey ordered to take charge. Govnor Oyetola bin appoint some monarchs weeks before handing over goment to Ademola Adeleke. Among dem be Akirun of Ikirun, Oba Yinusa Akadiri, Aree of Iree, Oba Ademola Oluponle and Oba Adegboyega Famoodun, wey de di former APC chairman for di state. Di appointments of Akinrun and Aree bin face plenti gbas gbos as some pipo for di two towns say e no pure. Gbege bin burst for Ikirun when di new monarch bin try enter di palace wey dey locked. Some residents for di town say dem no happy about di appointment say former govnor Oyetola dey try force am on top dem. Na dis one make dem lock di palace so di new Oba no go fit enter di premises. Executive Order number 6 Setting up Review Committees ""In line wit di executive orders Nos 2, 3, 4 and 5 wey already dey issue by me, I hereby order one set-up of di following Review Committees. Oga Adeleke bin also cancel “State of Osun” title reversal to di one wey di constitution recognise, ""Osun State"". E also say dem no go call di state ''State of di Virtuos'' again but ''State of di Living spring'' wey e dey known as before-before. Na former govnor Rauf Aregbesola change di name of di state wen e enta power for 2012. Govnor Adeleke bin add say di name change gatz reflect for all goment insignia, correspondence and signage Osun state rather dan State of Osun wey dey ''unknown to di Nigerian constitution''. ''An immediate reversal to di constitutionally recognized name of our state, Osun State. All goment insignia, correspondences and signages should henceforth reflect Osun state rather dan State of Osun wey dey unknown to di Nigerian constitution.'' E bin direct. Di state lawmakers in response say ''di usage of di State Anthem, Crest anf Flag na enactment of law and as such, im usage na law mata no be choice. ''while we dey aware of one copurt judgement in effect recognizing ''Osun State'', di Assembly, pending di determination and exhaustion of all legal means no go dey drag into di mata''. ''However, di State go and shall continue to dey known as di State of di Virtuos''." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cpd20vy02ego +politics How thousands march for Peter Obi for Abuja "Thousands of Nigerians, mostly young pipo enta road for Abuja to march for di candidate of di Labour Party for Nigeria 2023 presidential elections, Peter Obi. Di Obi supporters bin march from di Unity Fountain to di Moshood Abiola National Stadium. Pipo wey take eye see how e happun say di supporters plenti ""like ant"" for road. The pro-Obi supporters marched from the Unity Fountain to the Moshood Abiola National Stadium amid heavy security. Obi na former govnor of Anambra State and e dey contest di 2023 presidential election wit Bola Tinubu of di All Progressives Congress, APC, and Atiku Abubakar of Peoples Democratic Party, PDP. Di march by Obi supporters dey come afta several toks including from prominent Nigerians say dem no dey win election ontop social media. Obi get plecti supporters among di youths wey full for socisl media and dem tok about am and campaign for am well-well for social media. E also dey come some days before election campaign proper go start. Senator Ifeanyi Okowa wey be di govnor of Delta state and vice presidential candidate of di PDP bin chook mouth inside di candidacy and chance of di Obi wey decamp from PDP, inside exclusive interview with BBC Pidgin say e agree say Obi get popularity but e no get di kain experience to rescue Nigeria. ""I no tok say e no go get vote, e go get vote. Im experience dat one, e no fit waka for dis wan oh, e go hard, dat experience wey e get for dia e get experience wey you dey get, e no dey deep enough, even me wey dey currently as govnor now, as I dey tok, I dey di time of crisis I know how hard e be, I even wan learn dat wan from Atiku, becos e don get di experience from within di federal goment wey e be say dem fit handle am."" Na wetin Okowa bin tok. Peter Obi na politician and businessman. E be former govnor of Anambra state for southeast Nigeria. E serve two term between 2008 to 2016. Oga Obi bin dey di All Progressive Grand Alliance (Apga) before e join PDP for 2017. Im also be sabi pesin for wetin concern economy mata. For 2019, e come out as vice presidential candidate of Atiku Abubakar. But dis year 2022 e don decide to go for di president position. E first declare under di opposition PDP party before e decamp go Labour Party. Peter Obi say im administration as president go create jobs, boost Nigeria economy, and improve education." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cxx911y2gxdo +politics Manual collation of result go affect di outcome of 2023 elections in Nigeria? Dis na wetin experts tok "Di 2023 general election go be improvement of oda election wey di Independent National Electoral Commission (INEC) don do, sabi pesin tok. Ezenwa Nwagu, Chairman of Partners for Electoral Reform for Nigeria say need dey for pipo to sabi di electoral process. E say di 2022 Electoral Act (Amendment) don provide for di use of technology into Nigeria electoral system but “we no go fit handover all our electoral process to technology.” Oga Nwagu dey tok in reaction to tori say Inec say dem go collate result of di 2023 election manually. Festus Okoye, Inec Voter Education Commissioner say di commission go transmit results from polling units go dia result-viewing portal, IReV but say di collation go happun manually. “Difference dey between transfer or transmission of results and collation of results. “Section 50 (2) of di Electoral Act, 2022 give di commission di absolute discretion to determine di mode and procedure of voting in an election and di transmission of election results,” Okoye tok. Di comment cause confusion for pipo wey no understand wetin e mean – di Inec oga later explain am. Politicians for Nigeria dey fear say Inec fit introduce new guidelines ahead of di 2023 elections. Akogun Oyedepo, one oga for Social Democratic Party (SDP) opposition party for Nigeria say di electoral commission need to dey careful make dem no lose pipo trust. “We need to watch Inec wit suspicion. Maybe some tins dey go on wey we no know. Dem don clarify wetin dem mean but we still need to watch dem well,” Akogun, we be Lawyer tok. E say Inec get responsibility to improve on di gains “especially from di election for Ekiti and Osun.” As di confusion dey spread Ezenwa Nwagu say pipo need to understand di electoral process for di kontri before jumping into conclusion. “Transmission dey different from collation. No wia in di world wia dem dey collate result electronically. Dem must transfer result inside paper wey pipo go sign. “Di process of transferring result from electronic into form EC 8 from di polling unit to di final collation na manual process and nothing dey wrong wit dat. “Inec don improve well-well ova di last few years and Nigerians must support dem,” e explain. Ezenwa Nwagu, Chairman of Partners for Electoral Reform also say Nigerians no get any tin to fear as far as election conduct dey concerned. E say, “Nigerians suppose dey grateful say we fit transmit election result electronically. Dat na beta improvement on di part of Inec.” INEC national commissioner Festus Okoye say e dey surprise say pipo dey shock to hear say 2023 election result collation go be manual. Okoye tell BBC Pidgin say di procedure always be ‘essentially manual’ as dem do for Osun and Ekiti state govnorship elections. E say di manual collation process go follow dis steps: Nigeria election agency spokesman say pipo dey misinterpret di word transmission and collation. Festus Okoye say collation of result na ‘essentially’ manual. ""Collation of result ( dat na gathering of result) dey happun for ward, local goment, state level and presidential level.” “Collation na gathering of results into one document (form).” “Transmission of result, in fact di electoral act call am transfer (dat na manually) and transmission (dat na electronically).” Oga Okoye say each registrations area covers between 10 and 15 polling unit, so di Presiding officer for those unit go take dia result to one Collation centre.” “Wen dem get there, dem go handover everything wey dem get to di Collation Officer. ""Na di same process wey take place for Osun and Ekiti state governorship election,” Oga Okoye tok. INEC National Commissioner and Chairman of dia Information and Voter Education Committee, Festus Okoye tell BBC Pidgin say di BVAS dey perform three functions." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd198zr2927o +politics PDP National Convention 2021: Senator Iyorchia Ayuh na di PDP new national chairman Senator Iyorchia Ayu don become di new National Chairman of di Peoples Democratic Party (PDP) afta dia national convention wey happen for Abuja. Even though nobody dey drag di position wit am e still get 3426 votes to become winner. Di former senate president for di kontri third republic (1992-1993) be di consensus candidate for di position and go now dey dey in charge of di leadership of di main opposition party wit 19 oda officials wey dem elected for di PDP national working committee. Dem elect di new set of leaders for di Eagle's Square, Abuja , di venue for dia national convention wey start on Saturday and kontinu di early mor-mor on Sunday. Addressing di convention, Ayuh say even though di party don go see plenti rough road, im don come back to rescue di kontri from di mess wey e dey face. E say mani pipo think say di party convention go lead to break up of di party but as e be, dia dream no come thru. E say di party go move ahead to develop di Nigeria. Dis na di names of di PDP New leaders: Delegates for Nigeria main opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) gada to elect new national leaders wey dem believe go lead di party for di next four years. Ova 3,000 pipo gada for di Eagle's Square, for Abuja di konti capital for di national convention wit di hope say di leaders wey dem choose go give di party winning chance for di next major elections wey go dey for 2023. Di convention suppose shele today and tomorrow and na very important part for di party preparation for di 2023 elections for di kontri. Sometin wey di Chairman of di national convention committee, Ahmad Umaru Fintiri also believe as im say di new leaders go make di party dey kampe to win di 2023 election. Govnors and ex-govnors, party officials and ogbonge pipo for di party don show as security tight for di venue of di convention. BBC Pidgin tori pesin Dooshima Abu wey dey ground tok say di Eagle's Square just be like say dem do party as crowd full everywia. Ex-Senate president, Iyorchia Ayuh emerge as consensus candidate for di Peoples Democratic Party as dem dey find way to take ova power for Nigeria ahead of di 2023 general elections. Di endorsement follow afta di party national executive committee bin zone di national chairmanship position to di north. Oda tins to sabi about Senator Ayuh Na for Gboko, Benue state dem born Senator Ayu. E bin dey lecture for di University of Jos before e enta politics. At one time e comot from di Peoples Democratic Party go dia main opposition den join di Action Congress (AC). For February 2007, Ayu dey arrested on top accuse terrorism but dem later release am on bail. Im bin dey run tins as president of di senate for Nigeria Third Republic (1992-1993). Later e hold different ministerial positions inisde di Cabinet of President Olusegun Obasanjo between 1999 and 2007. All eyes son di PDP convention Di 2021 convention dey happun in di middle of plenti political kasala wey don shake di party but di 29 October judgement by one Appeal court for Rivers state make party members mind coolele. Di former chairman of di party, Uche Secondus, bin dey challenge im suspension and im bin try to block di party to hold di convention to hold. Many party members bin claim say Oga Secondus no sabi run di party wella and dat unda im tenure planti members cross go di opposition parties - sometin wey dem bin no like at all. Chairman of di national convention committee, Ahmad Fintiri bin tok say most of di positions for di party don get consensus candidate but three positions dey ground wey pipo dey contest. Dem be: See more fotos from di convention. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59104721 +politics 'Picking my vice president na mistake but God save me' - Obasanjo Nigeria former president Olusegun Obasanjo say picking im “number two” man na one of di mistakes wey im make for life. Obasanjo dey tok about im life experiences including matter wey concern di 1999 presidential election. Obasanjo second man for di two terms wey e serve as president na Atiku Abubakar wey be di PDP presidential candidate for di 2023 presidential election. Di former president make di comment wen e dey address some pipo for one leadership programme for Abeokuta, di Ogun state capital for South west Nigeria. Majority of di pipo wey di former president dey address na secondary school children wey come get leadership experience. Remember say Obasanjo become Nigeria president for 1999 – e serve two term between 1999 – 2007. For di programme, e dey tok about some of di mistakes im don make for life. E say pesin no fit avoid some kain mistakes but God get how e dey do tins. “I no go tok say I no dey make mistakes. I make plenty mistakes. “But one tin wey dey happun be say God neva disappoint me. And dat one dey very important,” e tok. Oga Obasanjo add say “For instance, one of di mistakes I make na picking a number two wen I wan become President. “But because na genuine mistake, God save me out of am.” As Olusegun Obasanjo return to politics e decide to contest di 1999 presidential election on di platform of di Peoples Democratic Party (PDP). E pick Atiku Abubakar as im number two pesin, im vice president. Obasanjo win di election afta e beat Olu Falae of di Alliance for Democracy and All Peoples Party. E serve as two terms president of Nigeria between 1999-2007 and for doz two term, Atiku Abubakar remain as im vice president. Atiku imsef dey eye di position of Nigeria president and na im go fly di flag of di PDP for di forthcoming Nigeria presidential election. E pick Govnor Ifeanyi Okowa of Delta state from di south-south region of di kontri as im running mate. Dis no be di first time Obasanjo dey tok about im vice president as pipo notice say di two pipo no get better relationship wen dem serve togeda. Ahead of di 2019 presidential election Atiku wey bin follow contest di election pay reconciliatory visit to Obasanjo. Ismlamic scholer Sheikh Ahmad Gumi and Bishop of Sokoto Catholic Diocese Bishop Matthew Kukah follow attend di meeting. For di years wey di two men serve togeda nobody know di true tori of wetin happun between dem. Chief Obasanjo, na retired general wey tok on many oda tins but most of im point na about di kain leadership wey Nigeria need. Apart from im choice of vice president Obasanjo also say many pipo tink say im decision to join Nigeria army na also mistake. “Wen Abach wan arrest me di American ambassador tell me. E say dem wan arrest me and say America say dem go give me asylum. “I say no, I no go run. That one sef fit be anoda mistake because I for die. So many tins wey I for see sa y na mistake, but God save me from dem all.” On di kain leaders wey dey contest election for Nigeria Obasanjo say despite di Not too young to run Law, “majority of doz wey dey contest na pipo wey dey 8p and 7o years od. “Di kain plenty money wey dey use for election. Unless you tiff money there is no way you fit do di work legitimately and till dey able to provide some tins. “But di most important tin be say hope dey. I believe say tins no go continue de way e dey go.” Chief Olusegun Obasanjo na former Nigeria president wey dem born for Abeokuta, south west Nigeria for 1937. For 1958 e Join di army and get training for Nigeria and abroad. E spend 21 years form im military career wia e serve for different position including as Commander during di Nigeria civil war. Im first administrative senior appointment na for 1975 wen e serve as minister of housing den later become chief of staff, supreme headquarters. Obasanjo become Nigeria of Head of state between 1976-79 afta di assassination of General Murtala Muhammad. Dem later comot am through coup. For 1995, e chop arrest on allegation say e dey plot coup against former Head of state General Sani Abacha. Di den goment sentence am to life in prison. Dem later reduce di sentence to 15 years afta some world leaders intervene for di matter. Obasanjo regain freedom for 1998 afta di death of Abacha and den immediately return to politics. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjk0y57x8x3o +politics Iran president no show face for CNN interview because Amanpour no gree use headscarf "Veteran CNN journalist Christiane Amanpour cancel one interview with Iranian President Ebrahim Raisi after e demand say she gatz wear headscarf for dia meeting for New York. Amanpour point out say no previous presidents binrequest dis when she interview dem outside Iran. She say Raisi aide tell her na because of ""di situation for Iran"". Di death of one woman wey dem detained for Iran for allegedly breaking headscarf rules don spark violent unrest there. Mahsa Amini, 22, fall into coma last week, hours after morality police arrest her. Officers reportedly beat Ms Amini head with one baton and bang her head against one of dia vehicles. Di police say no evidence of any mistreatment dey and say she suffer ""sudden heart failure"". Di protests, now for dia seventh day, don reach 80 other cities and towns for di Islamic Republic. At least 17 pipo don die. Di interview suppose be Oga Raisi first on US soil, during im visit to di UN General Assembly. Amanpour tok say she bin dey ready to conduct am when one of di president aides insist she cover her hair Oga Raisi request. ""Na New York we dey, where no law or tradition regarding headscarves,"" she tok later on Twitter. Amanpour tok say Oga Raisi aide make am clear say interview no go happun if she no wear headscarf, saying na "" matter of respect"". Her team walk away from di interview refusing wetin she call di ""unprecedented and unexpected condition"". Di US anchor later post one foto of herself without headscarf in front of one empty chair where Mr Raisi for siddon do di interview. Dem elect Oga Raisi last year and sign one order in August to enforce new list of restrictions. Di restrictions include di introduction of surveillance cameras to monitor and fine women wey no use veil or refer dem for ""counselling"", and mandatory prison sentence for any Iranian wey question or posted content against di hijab (headscarf) rules online. Dis lead to increase in arrests but also spark surge in women wey dey post photos and videos of demselves without headscarves on social media - something wey don only intensify in di days following Ms Amini death." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cnk83k9qz28o +politics Kogi state Governor Yahaya Bello say Senator Bola Ahmed Tinubu go be part of di pipo wey go make strong and better, youthful president for Nigeria Govnor Bello wey tok inside exclusive interview with BBC Pidgin, hail di APC leader as ogbonge elder statesman wey dey smart and wey don make many leaders, but e add say e know say Tinubu know im qualities and limitations and who go fit move Nigeria to di next level. Di govnor also tok about tori say e go run for di 2023 presidential race, Wike take on APC, im stand on coronavirus and Senator Dino Melaye accuse against im administration of financial fraud. Kogi state Governor Yahaya Bello say Senator Bola Ahmed Tinubu go be part of di pipo wey go make strong and better, youthful president for Nigeria. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56566791 +politics Trump: US must condemn white supremacy, call for death penalty for mass killers "President Donald Trump don condemn ""racism, hatred and white supremacy"" inside im address afta di mass shootings wey kill 29 pipo for di US states of Texas and Ohio. Im call for mental health programme as way to do gun control reforms, death penalty for anybodi wey commit mass killing and co-operation from political parties ontop gun laws. ""Mental health and hatred na im pull di trigger, no be di gun,"" Oga Trump tok for White House on Monday. ""In one voice, our nation must condemn racism, bigotry and white supremacy... dis bad mind must end. Hatred no get place for America."" Oga Trump also call for some changes to do di way some tins be for America. One of dem na to change law to allow authorities to seize weapon from pipo wey dem believe say wan use am do bad to odas and to demsef. Im also give order to di justice department to propose law wey go make sure anybodi wey commit hate crime and mass killing go face di death penalty. Democrats for di House of Representatives earlier dis year pass bill wey go force new background check for pesin wey wan transfer gun to anoda pesin. Di Senate wey na Republicans dey control am, never gree for di legislation." https://www.bbc.com/pidgin/world-49238437 +politics Bayelsa election: Court order DSS to investigate Deputy Governor for fake certificate One court for Abuja don order Department of State Services (DSS) to investigate allegation say di newly elected deputy govnor of Bayelsa State, Lawrence Ewhrudjakpo use fake National Service Corps Certificate take contest election. Oga Lawrence recently take oath of office alongside di State govnor, Douye Diri on February 14, 2019. Tori be say na one APC man from Bayelsa State, Benjamin Youdiowei na im carry di matter go court say Lawrence present forged certificate to Nigeria election body so e fit contest for di election. Di judge wey sit over di case, Abubakar Sadiq bin don issue arrest warrant of Lawrence Ewhrudjakpo for November 27, 2019 wen im no appear for court. So on Wednesday, Youdiowei lawyer, Seidu jibrin reveal say di police division wey di court ask to investigate di matter transfer di case to di Inspector General of Police Monitoring Unit. For im response, di judge say di police for come tell di court if dem no dey able to handle di case instead of dem to decide to transfer di case to IGP. Na dia di judge come cancel e former order wey say make police handle di case, e come tell di DSS wey be Nigeria secret police to take up di case. Oga Lawrence camp neva react to dis order from di Court. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51589951 +politics Guinea elections: Di 82-year-old wey wan rule for six more years Alpha Condé, Guinea 82-year-old head of state wan waka go polls dis Sunday to ask di kontri 5.4 million voters to vote am for third term, sometin wey go surely cause tension. Oga Conde entrance to power for December 2010 na di first correct democratic handover for di kontri 52-year independent history. Pipo bin witness plenti cases of force, brutality and military style of rule during im administration, especially di most recent one for 28 September 2009 massacre wia army kill at least 160 opposition supporters, rape 110 women wey bin attend rally for national stadium. President Conde imsef bin go jail afta im challenge General Lansana Conté wey bin rule from 1984 till im die for 2008, and im bin face big task to reform di security forces, dey transparent wit public finances and make di kontri begin dey respect human rights. Di past 10 years don bring ogbonge progress. Guinea get plenti mineral wealth and authorities don change regulation on how dem dey extract dem. Investors get confidence again, Simandou wey be one of di largest iron-ore deposit fit open and e go create thousands of jobs. Guinea don also try well-well in dia fight to tackle di Covid-19 pandemic. Oga Conde don also put Guinea back ontop di African diplomatic stage. But serious problem bin start wit human rights. Opposition figures like oga Diallo don also suffer plenti harassment. Katakata for streets between youths and security forces wey dey like use violence to do dia work upon all di training, still dey also cause wahala for political life. Ontop dat one, di promise wey goment make since say dem go do trial for di military figures wey get hand for di 28 September massacre still neva happen. Oga Conde contest for re-election go mean say di kontri go need to change di constitution through referendum alias voting for March. Di new constitution no go scrap di two term limit but e go reset di counter, meaning say di former terms wey any president don serve no go count. Early dis year, di regional joinbodi Ecowas (the Economic Community of West African States) bin sight 2.5 million ghost names for di voters register. Di opposition come decide to bone di election, wey go make Conde win easily. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54551320 +politics Curfew in Rivers State: Movement go dey restricted on Saturday as LG elections go take place "Local goment elections go hold for Rivers State, south-south Nigeria on Saturday 17 April 2021. For State Broadcast, Governor Nyesom Wike say di local goment election wey go elect local goment chairmen and councillors for di local goment legislative assembly go shele for all di 4442 polling units and 319 wards for di 23 local goment areas. Di Governor also ban all human and vehicle movement from midnight Friday 16 April to wen election go end by 5pm on Saturday 17 April, 2021 except for pipo and motors wey dey on essential duties wit genuine and valid identification. E follow direct security personnel to arrest and prosecute any pesin wey violate dis order. As e be so 17 political parties dey participate for di election but di major opposition, di All Progressives Congress (APC) no dey participate for di elections. Di Caretaker Chairman of di APC, Isaac Ogbogbula write letter to di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC to inform dem say di partyno go show for di election. Ogbogbula say APC no go participate because di electoral process dey faulty and members of di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC na card carrying members of PDP. ""Di electoral process dey already faulty wit di constitution of di membership of di commission, so dem no go fit conduct a free and fair local goment council election. ""We decide say as a party, we no go contest to give credit to illegitimate process, and we get di backing of di national secretariat of our party"", na so e tok Chairman of RSIEC, Justice George Omereji say even though APC no go participate for di election, dia Party logo fit dey on di ballot paper because dem don already print am before di letter come. Some opposition parties wey dey participate for di election do protest waka and accuse di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC) say dem dey deny dem funds wey dem need to prepare adequately for di election. Di opposition parties vex say RSIEC delay to give dem grants for di election and say dis one show say dem dey biased. But di RSIEC Chairman Justice George Omereji (Rtd) react to di claims by opposition parties say no provision for grants dey for any political party wey dey participate for di election. Police deploy 17,500 officers for di LG Polls Rivers State Police Command say dem don deploy 17,500 personnel in addition to deployments from oda sister security agencies, wey go provide safety, security and maintain law and order before, during and afta di elections. For statement wey di Police tok tok pesin Nnamdi Omoni sign say very important personalities (VIPs) or Politicians no go dey allowed to go any voting centre with dia security details. Movement go only dey allowed from dia house to di voting centres and back as e dey for di Electoral Act. E add say all entry and exit points to di State go dey completely blocked until di election finish and no commercial activities go dey allowed close to di polling units. Di statement add say restriction of movement go dey for di land and waterways as dem no go allow any motor or boat to wakabout during di time for di election. E come appeal pipo to participate and cooperate wit dem for a peaceful, free, fair and credible local goment elections." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56777477 +politics Presidential Election Ghana: Results na im Ghanaians dey wait, Police say five people die for Ghana election violence "Ghana Police Service say five people die as a result of de violence wey happen during de December 7 Presidential and Parliamentary election for Ghana. De police service talk is one for their Security Outlook report for de 2020 General Elections. ""De National Election Security Taskforce (NESTF) policed de 2020 Presidential and Parliamentary elections professionally and praise de public for their cooperation with pre-election security measures put in place and executed through de electioneering period. "" Ghana police service say between 0700 hours of 7th December 2020 and 1000 hours of 9th December, 2020, de Joint Operation Centre of de NESTF has record total of sixty-one (61) electoral and post electoral incidents nationwide. ""Twenty-one of de incidents na true cases of electoral violence, six of which involve gunshots resulting in de death of five."" Ghana police talk. De cases involving gunshots happen fo de following places; Bono East region, Techiman South constituency: Two people die and four person injure from shooting by security personnel for de collation centre during post-election period on 08-12-20. Northern region, Savelugu Constituency: One shooting incident by civilian(s) happen for de Police Station, when people gather de station during post-election period on 08-12-20 Northern region, Savelugu Constituency: One person die and three people injure from one shooting incident by civilian(s) in de community during post-election period on 08-12-20. De NESTF add say all dis incidents wey dem record na something wey people for fit avoid and so dem condemn decoccurrence and promises to investigate each one of them." https://www.bbc.com/pidgin/world-55246344 +politics Bayelsa election: Who be David Lyon, di new Bayelsa State Governor-Elect For di first time ever candidate wey no come from di ruling People's Democratic Party go be Governor of Bayelsa State, south-south Nigeria. Nigeria election body Inec declare opposition party candidate David Lyon Pereworimini as winner of November 16 governorship election for di state for early hours of Monday morning. Lyon wey be di All Progressives Congress (APC) candidate win di election wit total of 352,552 votes, based on say e score pass 25 percent of votes inside di results wey Inec Collation officers for all di eight local goment areas of di state. But who im be? 49 year old David Lyon Pereworimi na di CEO of Darlon Security and Guard, wey be private security company inside Bayelsa State. Na di Olodiana clan of Southern Ijaw Local Government Area na im Lyon come from. E fit be new commer for politics but im get small change for pocket. Im bin contest under di platform of PDP as an aspirant to represent di Southern Ijaw Constituency IV for 2011. Na for 2015 oga David Lyon port from PDP waka enta Nigeria ruling APC party. Oga Lyon attend Saint Gabriel State School Olugbobiri from 1978 to 1983, from dia im go Community Secondary School, Olugbobiri from 1984 to 1988. Im get National Certificate of Education wen e graduate from Rivers State college of Education. https://www.bbc.com/pidgin/tori-50458171 +politics APC national chairman: Abdullahi Adamu - Wetin you need know about am Senator Abdullahi Adamu na di new national chairman of Nigeria ruling All Progressives Congress (APC). E return unopposed on Saturday night for di party national convention wey happun for Eagle Square, Abuja, di kontri capital. APC say na 7,584 delegates decide who di party National Working Committee go be on Saturday. Tori be say Adamu na President Muhammadu Buhari choice as chairman. Afta some of di drama wey happun before di convention hold. Adamu bin dey endorsed as consensus candidate afta di oda contenders ste down for am. Adamu dey take ova more dan a year afta dem dissolve di National Working Committee (NWC) wey di former Chairman and Govnor of Edo state Adams Oshiomhole bin dey lead. Mai Mala Buni of Yobe State na im dem bin appoint to run di party affairs pending wen dem go organize di convention afta dem ask Oshiomhole to step down. Adamu, na serving member of di Senate wey dey represent Nasarawa West and former govnor of di state. Adamu na govnor of Nasarawa State for Nigeria from 29 May 1999 to 29 May 2007. E be di first executive govnor of di state. Dem born Adamu for Keffi and im early education begin for Senior Primary School Keffi before im proceed to Government Secondary School, Makurdi from 1960 to 1962. E proceed to Government Technical College, Bukuru, E also attend Kaduna Polytechnic for a Higher National Diploma. For 1992, e obtain LL.B (Hons) from di University of Jos and dem call am to Bar as a solicitor and Advocate of di Supreme Court of Nigeria for December 1993. Tori be say Adamu political career begin for 1977, wen dem elect am to di Constituent Assembly, wey bin draft di constitution for Nigeria Second Republic E also dey appointed to di National Constitutional Conference by General Sani Abacha administration for 1994 For di 1999 elections, Abdullahi Adamu run for di position of govnor of Nasarawa State under di platform of di People's Democratic Party. Dem re-elect am for April 2003 for a second term in office. Wen dem form di Nigeria Governors' Forum for 1999, dem elect am as di pioneer Chairman and im serve from 1999 to 2004. You fit call di APC dia national convention di big event before di big event. Di convention na wia dem for elect di National Working Committee, (NWC) wey go lead di affairs of di party into di general elections wey go happun for 2023. Some pipo don say di upcoming election go test APC and determine if dem go still be di ruling party come 2023. Di main task before di Adamu led APC party go be to ensure say dem front di right candidates and remain party wey dey in power come 2023. According to di time table wey di Independent National Electoral Commission, (INEC) announce, Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023. While govnorship and State Houses of Assembly votes go hold on March 11, 2023. https://www.bbc.com/pidgin/tori-60891276 +politics Result of Kogi election: EU confam violence for Kogi, refuse to declare elections dey 'free and fair' "European Union election observers on Sunday say di reports of violence, ballot box snatching and missing pipo for Kogi and Bayelsa elections no sweet dem for belle. For statement wey EU, UK, US, Germany, di Netherlands, Austria and Ireland join hand release on Sunday, dem confam say dia members use two eyes see violence and intimidation wey happun for Kogi. EU observers no determine di 16 November elections for Nigeria say e dey 'free and fair', as di dem do during di main presidential election earlier in di year for 23 February. ""Reports dey of kill kill and missing pipo, including INEC staff. We dey pray for all di victims and dia families."" But Nigeria election office - Inec don confam for statement say none of dis workers dey miss. ""Wetin also worry us na di vote buying wey dey open and di sure reports of ballot box snatching for both Bayelsa and Kogi,"" di obodo oyinbo observers bin tok. Di states of Kogi and Bayelsa enta poll on Saturday to elect new govnors and lawmakers. Di observers para for why e be say pipo no fit vote in peace, without 'intimidation and harassment'. According to di joinbodi, dem don participate for every major election for Nigeria since 1999. And say di work wey dem dey follow INEC and di Nigeria authorities do, no get partiality inside." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50447512 +politics Tinubu deny tori say im wan contest for 2023 presidency "National leader of Nigeria ruling All Progressives Congress (APC), Bola Ahmed Tinubu don deny di rumour wey dey spread say im get plan to contest 2023 presidential election and take ova from President Muhammadu Buhari. Oga Tinubu wey also be former Lagos state govnor, tok say im no sabi di group wey dey carri im mata for dia head and dey campaign on behalf of am. For di tweet wey both Bola Tinubu and APC carry come out, dem say dia hand, legs and bodi no dey part of dat group wey dem call 'Asiwaju Reloaded Ambassadors' Nigeria' ""We don see foto of face caps, T shirts, shirts and even leaflets wit Bola Tinubu 2023 wey dem write inside and wey one faceless group wey call demsef 'Asiwaju Reloaded Ambassadors' Nigeria dey do. ""Asiwaju Bola Tinubu no sabi either di group or dia souvenirs."" ""We dey hereby, through dis medium, dey deny say wey no know dis group and comot our body plus both Asiwaju Tinubu from di group wey dey print and dey share materials wey nobody send dem to do.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-48939271 +politics Serap sue CCB to publish properties of Nigeria Govnors, Presidents since 1999 Civil society group, Serap on Sunday drag Nigeria special office wey dey shook eye for property of politicians go Lagos High Court. Socio-Economic Rights and Accountability Project want di court to force di Code of Conduct Bureau to publish di properties of pipo wey don be Govnors and Presidents since 1999. Di group argument wey dem cari go court na say di Code of Conduct Bureau no get reasonable grounds to deny SERAP di Freedom of Information 'FOI request', as e dey in di interest of justice, di Nigerian pipo, openess and to dey accountable to publish full informate of di wealth wey presidents & state govnors get since di return of democracy in 1999. 1. Freedom of Information Act Serap say even tho say constitution no make am by-force for public officers to declare dia assets, di Freedom of Information Act 2011 don provide method for di Code of Conduct Bureau (CCB) to make sure say magomago no dey di asset declarations by public officers wey dem elect. 2. Fake declaration - corruption accuse Di group also argue say as na say na fake declaration of dia assets na wetin make plenti public officers dey face corruption accuse or dey guilty of corruption, di CCB no suppose dey allow politicians dey yeye di asset declarations provisions of di constitution by allowing dem to continue to dey take advantage of di comma wey dey legal processes for dia own illegal benefit. 3. Quality of public discussion Di quality of public discussion go drop well-well if CCB no dey provide information from public authorities, and to guarantee freedom to tok witout di need to add di right to know go be formal exercise, Serap add. No be today di group don begin shook mouth on top mata wey concern goment and openness ontop goment wealth and how politicians dey use or spend goment money. Serap bin shook mouth make Bayelsa State goment drop life pension for lawmakers, and e be like say dat one work as las las di govnor no gree sign di law. Na dem be one of di civil society groups wey boldly come out to demand say make Nigeria President Muhammadu Buhari investigate one powerful govnor for northern Nigeria if im dey truly fight corruption. Dem say say Buhari must investigate Govnor Ganduje video wey show am dey put money insie babariga if im dey fight corruption. Di Socio-Economic Rights and Accountability Project don also sue govnor Okowa for poor education standard inside Delta state, southern Nigeria. Dem para say di condition of primary schools all ova Delta state for Nigeria suggest say goment don abandon poor children. But many of di court cases wen dem don file so far, neva get head. https://www.bbc.com/pidgin/tori-48721981 +politics PDP Convention: Appeal Court don rule in favour of Peoples Democratic Party to hold national convention on 30 October One Appeal court for Port Harcourt, Rivers state don rule say in di favour of di Peoples Democratic Party (PDP) National Convention wey go hold on 30 October. Justice G.O. Kolawole, wey read di ruling on behalf of one three-man panel troway one request to stop di convention wey di suspended chairman of di party, Uche Secondus file. Oga Secondus bin dye also challenge im suspension as di PDP national chairman. Di court however tok say dem go hear di main suit wey Secondus cari come to challenge im suspension for anoda date. Di Peoples Democratic Party na di main political opposition party for Nigeria and di national convention suppose set ground for di party plans and roadmap for di next major elections wey go shele for 2023. Wetin dey expected be say di thousands of delegates wey show go elect di party national leaders on 30 October, and di believe be say di new leaders go drive di party to success for di next four years. Di 2021 convention dey happun in di middle of plenti political kasala wey don shake di party but today's judgement from Appeal court don make party members mind coolele. Now wey di party don get green light to go ahead wit di convention, di party go hold open secret ballot to elect im new leaders. Oga Fintiri say many of di leader na consesus candidtates dem bi and say na only three position wey opponents dey. E say even though some of di leaders dey unopposed, di delegates go still vote for dem sake of say na how e dey for dia constitution. E follow tok say even though di party dey do early convention, those wey dem elect no go enta power until di tenure of di old leaders expire. Di Uche Secondus-led exco gatz leave office for 8 December while di new one go resume work from di 9 December. Why be say Uche Secondus dey drag di PDP For 2017, party delegates bin queue for Eagle Square to elect Secondus and oda national leaders dem. Sake of im victory, e come be di 11th National Chairman of di party. Secondus promise to unite di party and provide vibrant opposition to di ruling party and prepare di party for election for 2023. But just months to di end of im tenure, kasala burst - some party pipo blame am say e no get beta leadership skill plus say under im watch, some govnor and legislators leave di party to dia main opposition, di All Progressives Congress (APC). Na inside dis trouble na im di PDP River state chapter ward decide to suspend am and court follow support di suspension. Secondus go court to challenge im removal - sotey sake of all di court wahala, di party no fit resolve di mata come ask di deputy chairman, Yemi Akinwonmi to take office. Di culture of PDP National Chairmen to no finish dia tenure no be new tin. Di party don get 11 chairmen so far - among di eight (8) wey dem elect na only one Ahmadu Ali, wey don finish im tenure. https://www.bbc.com/pidgin/tori-59092736 +politics Yemi Osinbajo: Nigerians react as Vice President Prof Yemi Osinbajo don declare interest to run for presidency for 2023 "Nigeria Vice President Yemi Osinbajo don declare im intention to run for di next kontri president. Im write ""I am today, wit utmost humility formally declare my intention to run for di office of di President of di Federal Republic of Nigeria on di platform of APC."" Osinbajo dey hope to succeed President Muhammadu Buhari wey im tenure end for May next year. For inside one video wey im post for im social media handles, Osinbajo say ""If by di grace of God and di will of di pipo, dem give me di opportunity, then I believe say first, we must complete wetin we don start, to radically transform our security and intelligence architecture, complete di reforms of our justice system; focus on adequate remuneration and welfare of judicial personnel and make sure say justice dey for all and we observe di rule of law."" E also say im go rapidly advance infrastructure development for di kontri, especially power, roads, railways, and broadband connectivity, to provide excellent environment for businesses to grow. ""To take agriculture revolution to di next level, especially mechanisation and to develop di farm-to-table value chain; make sure say di goment, im agencies, and regulators, serve di business community, create tech economy wey go provide jobs for millions of young Nigerians."" ""For di past seven years I don serve as vice president under a true Nigerian patriots as as a servant of di nation for war and peace. ""I don work through some of di most difficult times for di history of our nation."" E add am say im goment as Vice President togeda wit President Muhammadu Buhari don remain focus on securing di kontri to provide infrastructure and growing di economy. ""I don serve di goment in several capacity and I don represent di kontri for many places in several engagements. ""I don dey for all local goments for Nigeria, I don dey for di house of many ordinary Nigerians."" Professor Yemi Osinbajo say im sabi di hopes and aspirations of many Nigerians. Di 65-year-old vice-president go face-off wit other aspirants within di ruling APC party to gbab di presidential ticket. Dem include im benefactor Bola Ahmed Tinubu -di former governor of Lagos - wey dem don often describe as di strong man of di party. Others na di governor of Kogi state, Yahaya Bello, and di current Transport Minister Rotimi Amaechi. Di main challengers for di opposition PDP party na former Vice-President Atiku Abubakar, Governor of Rivers state Nyesom Wike, Governor of Bauchi state Bala Muhammad, Governor of Sokoto state Aminu Tambuwal and former Senate President Bukola Saraki. Di presidential election dey scheduled to hold for February next year. Yemi Osinbajo na Nigerian lawyer, professor, and politician wey be di 14th and current Vice President of Nigeria since 2015 under di All Progressives Congress (APC). Im bin previously serve as Attorney General of Lagos State from 1999 to 2007 and hold di title of Senior Advocate of Nigeria (SAN). For 1999, Osinbajo gbab appointment as Attorney-General and Commissioner for Justice for di cabinet of Lagos State Govnor Bola Tinubu. Afta e serve during both of Tinubu four-year terms, Osinbajo comot government for 2007 and return to law. E follow dey do lecturing plus preaching for di Redeemed Christian Church of God. Before di 2015 presidential election, dem chose Osinbajo as running mate to APC nominee Muhammadu Buhari. Na dia ticket defeat di den-incumbent President Goodluck Jonathan and Vice President Namadi Sambo. Four years later, im win re-election. Osinbajo tenure dey marked wit rising profile, especially wen im take power as Acting President wen president Buhari travel abroad. We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61064188 +politics Bayelsa Governorship election 2019: Supreme Court cancel David Lyon election, declare Douye Diri of PDP winner Supreme Court for Abuja don cancel alias nullify Bayelsa State governor-elect David Lyon as winner of di 2019 election for di state. Di five-man panel of Nigeria highest court now, don declare PDP candidate Douye Diri as winner of di state governorship election. APC candidate David Lyon bin dey prepare for im inauguration as Govnor of di state wey suppose happun on Friday 14 February, 2020 before dis ruling from di Supreme court comot. For November 2019, Nigeria election body Independent National Electoral Commission (Inec) bin declare Lyon of All Progressives Congress (APC) as winner of di 16 November governorship election wit total of 352,552 votes, based on say e score pass 25 percent. For Inec result, oga Douye Diri of People's Democratic Party score 143,172 votes. Normally for Nigeria, Supreme Court judgement be final and nobodi fit change am. On 12 November, 2019 Federal High Court for Abuja bin disqualify Degi-Eremienyo wey contest as Lyon deputy say e forge certificate give Inec. Today, Thursday, di Supreme Court come confam di decision of di High Court say true true David Lyon running mate, Degi-Eremienyo forge certificate give Inec. Di court rule say Degi-Eremienyo disqualification spoil di joint ticket wey di governorship candidate, Lyon, run for and win di 2019 election. Jubilation full ground for Yenagoa, Bayelsa State capital even as David Lyon bin dey prepare for e inauguration. Pipo begin play music plus beat drums as tori of di Supreme Court ruling reach dia ear. Even sef, some pipo begin bring down flags of APC wey dey for streets of Bayelsa to signal say na PDP dey on board now. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51491348 +politics Adams Oshiomhole say 'I still be APC National Chairman' "Adams Oshiomhole wey chop high court order on Wednesday say make im no parade himsef again as national chairman of Nigeria ruling political party; All Progressive Congress (APC), don beat chest come outside say im still be di national chairmo of di party. Oga Oshiomhole, through im press secretary, Simon Ebegbulem, tell BBC Pidgin say, dem don already carri di mata go Court of Appeal for ""stay of execution plus appeal di ruling."" ""Wit di process wey currently dey before di Appeal Court, Comrade Adams Oshiohmole, still remain di national chairman of di party."" Ebegbulem tok. On Wednesday, Abuja High Court give order make Adams Oshiomhole stop to dey parade imself as di National Chairman of di ruling All Progressives Congress (APC for Nigeria. Meanwhile di Acting National Secretary of di APC, Victor Giadom, bin tell BBC Pidgin say di party accept di earlier court decision to suspend Adams Oshiomhole as di party national chairman. Di party national secretary say, since na competent court of justice give order for di suspension of oga Oshiomhole, ""as a law abiding political party, we go respect all lawful court order."" Oga Giadom say, di National Working Committee go get to meet togeda to decide weda or not dem go appeal. Justice Danlami Senchi wey give di court order on Wednesday say di political parties must obey dia constitution and as im ward bin don suspend Oshiomhole, im no suppose dey function as di National Chairman of di party pending wen dem go hear di mata. Di judge fix di case for April 7 and 8, 2020. Na for November 2019 Adams Oshiomhole,bin first chop suspension as di national chairman of Nigeria ruling party from im native branch wey be Edo State chapter of di All Progressives Congress Party . Dat time, di chairmen of APC, for 18 Local Goment Areas for di state pass vote of no confidence for Oga Oshiomhole on Tuesday, di State APC Chairman, Aslem Ojezu tell tori pipo. Tori be say oga Adams Oshiomhole and Osho baba as some pipo dey call am and im state Govnor Godwin Obaseki dey get some kain quanta on top who dey in charge for di state." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51745682 +politics Thanksgiving 2021: Happy Thanksgiving Day messages from Biden, Obama, Clinton, Harris "Thanksgiving Day 2021 don reach again ooooo! Na one ogbonge traditional celebration wey United States dey do on di fourth Thursday inside November evri year. Dis one mean say na today wey e November 25 na im e be. Plenti pipo don dey tok about di thanksgiving already. Some ogbonge pipo for United States don send goodwill messages too about di 2021 Thanksgiving mata. ""Happy thanksgiving evribodi, dis time na special time for evribodi for America. Dis year di blessings of Thanksgiving dey very meaningful. President Joe Biden tok on Thursday. Afta we dey apart last year, we get to appreciate di little tins wey dey happun to us wey we no dey appreciate before-before. We no fit plan or replicate di music of laughter wey dey warm, kitchen wey full, di sound of small small legs wey dey waka, di circle of faces, we dey gada around di dinning table, wey dey shine for candlelight. As we gada togeda again for our tables and our hearts dey full of grace gratitude for all di pipo we love. As a commander in chief, I especially grateful to our service members and dia families, for di sacrifices dem don make for our nation. Di American leader go on to say: ""While we dey celebrate togeda, many of dos military families go dey apart from dia loved ones."" ""Weda your husband or wife dey deployed or you park go dey bas for anoda place, di holidays no go be di same without di pipo and di communities wey dey make di holiday special."" We dey thank una for una service. President Biden tok. ""As we dey give thanks for wetin we get, we dey also keep for our hearts di pipo wey we lose, and di pipo wey lose plenti tins too."" E add say ""di pipo wey get empty seat for dia kitchen table or dinning room table di year sake of di virus or anoda bad twist of fate or accident, we dey pray for dem."" ""As we dey travel dis year, we don see, and we don dey inspired by di unbreakable threads wey dey unite all of us, family and faith, kindness and compassion, di love for dis kontri we all of us call home."" Oga US Presido wey bin stand should to should wit im wife add say: ""Una dey make us proud evriday as we dey serve as una President and First Lady."" ""And from di Biden family to yours, Happy Thanksgiving, God bless you and may God protect our troops and dia families."" To our military families wey dia loved ones dey serve overseas, and to all Americans across di kontri, I dey wish you and yours a happy Thanksgiving. We hope say your day dey filled wit blessings, laughter, and gratitude. Barack Obama write on Thursday say: ""Dis Thanksgiving, dey remind me of many tins—big and small—we need to dey thankful for."" ""Michelle and me dey specially grateful for our family, for the progress we dey continue to make as a country, and for di young leaders around di world wey dey work to build beta future."" ""We dey send our warmest wishes to everyone celebrating today, and hope say you enjoy dis wonderful and safe Thanksgiving."" Former US Secretary of State and First Lady, Hillary Clinton write say: ""Happy Thanksgiving! Dis one na all di more joyful for di greater opportunities to gada more safely wit family and friends."" ""I dey wish una a wonderful and delicious holiday full of gratitude."" Thanksgiving na holiday wey Americans dey celebrate every year for di fourth Thursday for November. Many pipo dey use di day to celebrate all di good things for life and spend time with dia family members. Dis period dey mark di beginning of Christmas holiday season. Dis na one of those kwesions nobodi get di ansa to! For olden days one Pilgrim wey dem call Edward Winslow write letter about di popular turkey food wia im mention turkey hunt before dinner. Some pipo tok say as wild turkey full ground wen native Americans come di area, e make sense for dem to choose am as dia food. As e be today so, na USA get turkey pass for di world. Pipo dey eat turkey well-well for Thanksgiving for America pass Christmas and di number of turkey wey dem dey chop for di kontri every year fit reach 50 million. Every year di president dey save at least one turkey, from oven. Di public go present di commander-in-chief with two turkey before Thanksgiving and na di president go save at least one of dem. Dis tradition don dey go on now since 1948. Thanksgiving Day start when Europeans travel go America to start new life. For 1621 one group of Europeans, wey dem call 'Pilgrims', invite di local Native Americans for party. Before now di Pilgrims bin get wahala with farming for many years. Di Native Americans teach di Pilgrims how to farm, and to thank dem, di Pilgrims invite dem for big party." https://www.bbc.com/pidgin/world-59423521 +politics Boris Johnson resignation na wetin some MPs want now afta Court say im do wrong "British politician, Jeremy Corbyn and oda MPs don say make UK Prime Minister, Boris Johnson resign afta Supreme Court for UK say im decision to suspend Parliament no follow di law. Di Labour leader tok for im party conference wey happun for Brighton on Tuesday, say make Oga Johnson ""Consider im position"". SNP Westminster Oga Ian Blackford tok give BBC say dem go do dia work to make sure dem end Boris Johnson goment. Im tok say dem go comot di Prime minister with no confidence vote if e no gree go. Leader of di Liberal democrats, Joanne Kate Swinson add her voice for di mata. For her interview with BBC, she say ""Oga Johnson no dey fit for office, He musto resign!"" ""He dey prepare to mislead di Queen and di whole kontri pipo,"" She tok. Oga Johnson suspend Parliament for five weeks earlier dis month. Im argue am say di suspension dey necessary so that dem go fit do Queen's speech and comot new legislative programme on how dem go comot from European Union. But di Supreme court for UK say e dey wrong to stop MPs to carry out dia work as dem dey prepare for Brexit wey suppose shele on October 31. Supreme Court President Lady Hale tok say ""di effect of di suspension on di fundamentals of democracy dey extreme"" and di goment no dey justify to do am. Di Members of Parliament go return to work on Wednesday at 11:30 BST afta di court ruling." https://www.bbc.com/pidgin/world-49816234 +politics Fatima Waziri-Azi: NAPTIP new Director General wey President Buhari appoint - Profile "Fatima Waziri-Azi na di tear rubber Director General of di National Agency for Prohibition of Trafficking in Persons [Naptip]. President Muhammadu Buhari approve di appointment of Dr. Waziri - Azi, according to statement from di presidential palace. Her appointment dey possible after one recommendation of di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Farouq, di statement add. Di recommendation be say e dey ""urgent for di Ministry to intensify on di existing capacity inside NAPTIP in order to achieve Key Result Areas as identified."" Di recommendation of Fatima Waziri-Azi dey based on her ""pedigree, vast experience and proven track record to drive di agency forward and consolidate on wetin dem don achieve so far."" NAPTIP be di Nigeria Agency wey dey in-charge of addressing matter wey relate to human trafficking especially women and girls. So Waziri-Azi work na to fight against human trafficking especially women and girls from Nigeria to 'di abroad' Here be wetin BBC Pidgin find out about Fatima Waziri-Azi: Senior Special Assistant to di President on Rule of Law Since August 2019 before her new appointment. Fatimah Wazri be Rule of Law Advisor to di President at Office of di Vice President of di Federal Republic of Nigeria from Nov 2018. She get plenty certificate as she go school wella. Bachelors of Law, Barrister at Law, Masters in Law, Doctorate in Law Associate Member, Chartered Institute of Arbitrators, UK (ACIrb) Member, Nigerian Bar Association (NBA) Member, New York County Lawyers Association (NYCLA) Member, Association of Women in Development (AWID) Member, Women in International Security (WIIS) Online Volunteer, World Pulse. Madam Fatima be Associate Professor & Former Head of Department, public law at di Nigerian Institute of Advanced Legal Studies since February 2012 till now. Dr Fatima Waziri-Azi get experience working experience from both naija and di abroad. She get Specialties for Anti-Corruption, Women Human Rights, plus Research and Training. Di ogbonge lawyer bi gbab her first degree in law for Ahmadu Bello University Zaria for 2001. Na after den she be go obodo oyinbo schools like Havard, University of Pitsburgh plus many oda schools." https://www.bbc.com/pidgin/media-58505677 +politics UK Prime ministers Queen Elizabeth II don appoint - Fotos & History Di Queen don appoint every prime minister since Anthony Eden for 1955. But Liz Truss go be di first she dey invite come Scotland. Traditionally, di new PM go meet di Queen for London inside Buckingham Palace. On Tuesday di monarch meet wit di next prime minister for Balmoral. Di Queen ascend di throne for 1952, wen Winston Churchill be prime minister. See di images of all di 15 leaders from her 70-year reign. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2lgv0ezdgeo +politics French elections 2022: Macron and Le Pen dey battle for presidency "Emmanuel Macron don win di first round of di French election and far-right rival Marine Le Pen go fight am for di presidency for a second time. ""Make no mistake, we neva decide anytin yet,"" im tell im supporters. In di end, Macron win a convincing first-round victory, but opinion polls suggest say di run-off fit dey much closer. Ms Le Pen call on every non-Macron voter to join her and ""put France back in order"". Wit 97% of results counted, Emmanuel Macron gbab 27.35% of di vote, Marine Le Pen 23.97% and Jean-Luc Mélenchon 21.7%. Veteran far-left candidate Jean-Luc Mélenchon poll even better pass five years ago and now e get di unlikely role of kingmaker. ""Make una no give a single vote to Marine Le Pen,"" im warn im supporters, but unlike other candidates, im no support di president instead. Later for di evening, Mélenchon activists gada outside im campaign HQ dey think say im fit even come second but e no happun. Making up more than a fifth of di vote, Mélenchon voters fit decide di final round of dis election, yet many of dem fit no vote for di second round. Na Twelve candidates dey run for di election but dis na di only three wey get more than 10% votes. Many of di voters be like dem embrace di idea of tactical or ""useful"" voting, decide say di other nine candidates no get hope to make di run-off. Di battle for votes don start Marine Le Pen fit count on supporters of Eric Zemmour, wey im hardline nationalism give am fourth place and 7%. Nationalist Nicolas Dupont-Aignan don also support her. E don already make impressive 33% of di entire vote. Oga Macron team don already dey plan a series of big rallies and major TV appearances. Most of di other candidates on di left dey support am like Valérie Pécresse, but one-time Socialist candidate Ségolène Royal say di president need ""earn"" im victory. Ifop pollster François Dabi say im company 51%-49% estimate na di closest dem don ever predict. One BFMTV poll put di gap for 52%-48% and one Ipsos poll suggest say e still dey wide. Addressing im supporters,Oga Macron be like one relieved man and im promise to work harder than im do for di first part of di campaign. Im only begin campaign eight days before, im mind bin dey more focused on Russia war for Ukraine. ""Wen di extreme right in all im forms represents so much of our country,"" im tok, ""we no fit feel say things dey go well."" Im address Le Pen voters too: ""I wan convince dem in di next few days say our project answers solidly to dia fears and challenges of our time."" Ms Le Pen say time don reach for a ""great changeover"", wit a fundamental choice on 24 April of two opposite views: ""Either division and disorder, or union of di French pipo around social justice wey tanda well."" She don built her campaign around di cost-of-living gbege wey dey face plenty of Europe, promise to cut taxes and waive income tax for under-30s. E don get plenty tok-tok on nationalism, but she say she want referendum on restricting immigration, radical change to di EU and a ban on di Islamic hijab in public areas. Di campaign only begin ginger like two weeks ago, first na sake of di Covid pandemic and then di Russian war. But in di end, di spring sunshine mean say turnout no dey as low as pipo dey fear, at almost 75%. E don already dey clear from Oga Macron speech im plan to target Ms Le Pen close links wit di Kremlin. Although she don condemn Vladimir Putin war, she visit am before di previous election and her party collect Russian loan. Im want France wey dey make alliances wit great democracies to defend imself, e tok, no be state wey go comot Europe and get only populists and xenophobes as padi-padi. One in four young voters support di president, although more than one in three 18-24 year-olds choose Jean-Luc Mélenchon, according to Elabe pollsters. Marine Le Pen perform best among 35-64 year-olds, while di over 65s favour di president." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61064185 +politics Attack on Borno state governor: Why ‘Boko Haram’ dey target Babagana Zulum? On Sunday, militants wey dem suspect to get link with Islamic State (IS) group re-attack di convoy of di governor of Borno state, Babagana Zulum afta one attack wey don first bin happun on Friday. One official wey bin dey among di convoy tell BBC say di militants use one donkey strap with explosives to weley di convoy of di governor but report say no body die. Dis one dey happun afta Governor Babagana Zulum bin don survive one attack by militants as e dey travel go one area near Lake Chad on Friday but unlike di Sunday attack, at least 18 pipo -14 police officers and soldiers and four civilians die for di Friday ambush. No be di first or second time wey attack on Governor Zulum dey happun. For July dis year, local media report say e survive one ambush wey suspected Boko Haram gunmen bin plan for am during one trip to Monguno and Baga towns to distribute food to IDPs. Di official wey dem among di convoy say wen soldierssee di donkey wey dem strap with explosive for road, dey come shoot am and di explosives go off, den di militants immediately come out from dia hide-out and begin shoot di convoy. Some of di militant die during di shoot-out and nobody for di convoy - including di governor - injure but some bullet damage some motor, di official tok Di governor bin carry waka go round Baga town to prepare for di return of thousands of residents wey Boko Haram militants displace for 2014. Boko Haram don split into different group since, with one breakaway group - Di Islamic State West Africa Province wey dey pledge allegiance to IS. Di Islamic State (IS) group bin don tok say na dem carry out di Friday attack. E no dey clear why dis attack don happun to Governor Babagana Zulum convoy twice during di weekend and once for July dis year. But di Governor dey try help thousands of pipo wey Boko Haram katakata don displace from dia houses. On Sunday im return back to Maiduguri, di state capital afta e spend two nights for Baga where e receive over 1,000 internally displaced pesin wey willingly return to Baga town. Di Governor dey for Baga between Friday to Sunday dey supervise di preparation for safe resettlements to di town wey use to be strategic to boko haram. E dey always try to assist pipo wey dey for IDP camp as a result of di Boko Haram Insurgency. Oga Zulum recently tell United Nation resident humanitarian coordinator for Nigeria, Mr. Edward Kallon and oda stakeholders to join hand address di root causes of Boko Haram insurgency. E don also promise Borno state pipo im commitment to tackle di security situation for di state. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54330849 +politics Colonoscopy: Kamala Harris briefly take over as acting U.S. president as Joe Biden do colonoscopy "U.S. President Joe Biden briefly transfer power to Vice President Kamala Harris on Friday as im do a colonoscopy. Dis short-period transfer make her [Harris] di first woman to hold di presidential control in US history. Biden, a Democrat, bin alert leaders inside Congress of di power transfer at 4:10 PM Lagos time and take back control at 5:35 PM, Reuters report say di White House tok. Di president bin undergo a normal physical examination for Walter Reed military hospital outside Washington. White House spokesperson Jen Psaki say Biden speak to Harris and White House chief of staff Ron Klain after di procedure and bin dey ""in good spirits."" Biden power transfer occur while im bin dey under anesthesia for di colonoscopy. Harris bin work from her office for di West Wing of di White House during dat time, Psaki tok. Harris na di first woman to serve as vice president of di United States; no woman don ever be president inside USA nearly 250-year history. Di moment, while e dey historical, no count as say woman don serve as U.S. president, according to Debbie Walsh, di director of a research group - Center for American Women and Politics. But e go reinforce say ""for di first time a woman na di number one pesin in di line of succession,"" Walsh tok. ""E still no be di presidency, dat glass ceiling never dey broken yet."" Di U.S. Constitution's 25th Amendment set out a process for di president to transfer power when he dey unable to discharge im duties. Presidential power don dey transferred to di US vice president before, when President George W. Bush bin do colonoscopies in 2002 and 2007. Biden, wey turn 79 on Saturday, na di oldest pesin to take office as U.S. president, leading to high interest ontop im health and well-being. Although speculation don dey continue about whether im go run for re-election in 2024, he don tok say e expect to seek a second four-year term. Biden bin promise to be more transparent about im health than di man im take over from - Donald Trump. Di Republican visit Walter Reed in 2019 for one undisclosed reason wey a former press secretary, Stephanie Grisham, later reveal say na for a colonoscopy. During di colonoscopy, a single 3 mm benign-appearing polyp na im dem identify and ""remove without difficulty."" Dat na wetin Biden doctor, Dr. Kevin O'Connor, write in a summary of di president medical exam wey di White House release. One evaluation of di polyp dey expected to happun by early next week, O'Connor tok. Di physical, wey dem conduct a day before di president 79th birthday, find oga Biden to be in overall good health, according to di summary. O'Connor acknowledge Biden always coughing and throat-clearing, wey don be evident during some of im speeches. For di summary of di president medical exam, O'Connor say di cough dey likely a symptom of gastroesophageal reflex, wey fit also contribute to occasional sinus congestion. O'Connor, wey say Biden don display such symptoms ""for as long as I don known am,"" tok say one otolaryngology exam find no polyps or tumors. And a gastroenterology exam find no signs of ulcers, cancer or oda serious conditions. A lung examination come back normal. Di medical report add. A colonoscopy be a test to check inside your bowels, and e fit help find wetin dey cause bowel symptoms, according to NHS UK. During di procedure a long, thin, flexible tube with a small camera inside na im dem go pass into your bottom, and e dey considered a safe procedure. Dem dey perform Colonoscopy for many purposes, with di NHS explaining: ""A colonoscopy dey often done to check wetin dey cause your bowel symptoms, such as: bleeding from your bottom or blood in your poo diarrhoea or constipation wey no dey go away losing weight or feeling really tired for no reason ""Most of di time e no go find anything to worry about.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-59285988 +politics Ghana opposition NDC list 51 family and friends inside Akufo-Addo govment "Opposition party for Ghana, National Democratic Congress (NDC) release list of 51 people wey dem say be families and friends of de Akufo-Addo govment. Dem address Ghanaians on Tuesday after NDC National Communications Officer Sammy Gyamfi describe dis as de evidence of nepotism for Ghana. Around de 2016 General Elections, then NPP candidate Nana Akufo-Addo promise Ghanaians during de campaign say he no go operate family and friends govment. ""My wife go dey in charge of de distribution of contracts in dis country…I no go operate family and friends government in Ghana,"" Akufo-Addo talk supporters during dema fundraising event for Kumasi Nana Akufo-Addo. ""I go assure you say everyone for dis country inside go get en fair share of de national cake"" he add. De NDC say contrary to de claims wey then candidate Akufo-Addo make, he appoint en family den friends for government inside. According to NDC Communications Officer, Sammy Gyamfi, de President dey go against en pledge for fight nepotism and cronyism for Ghana. De NDC list relatives of de President, Vice-President, Finance Minister, relatives of some of en appointees den tins all who get appointment for govment inside. Elements from de ruling government explain say de relatives of President Akufo-Addo from de 1960s always dey inside politics so if dem get appointments e no for surprise anyone. Dem also dey talk say most of these people get de qualification to occupy de offices so that no be issue." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50315150 +politics Ministerial list: Fashola, Lai Mohammed, Saraki get nomination Nigeria President Mohammadu Buhari don send di list of 42 ministerial nominees go Senate for confirmation. Senate President Ahmed Lawan read out di list of di nominees to di members of di Senate. Some of di names wey dey di list na Lai Mohammed wey be former minister of Information from Kwara State, Babatunde Raji Fashola former Minister of Works and Housing from Lagos and Rotimi Ameachi former Transportation minister from Rivers state. Di new names wey dey inside di list na former Osun state govnor Rauf Aregbesola, former Senate Presido sister Gbemi Saraki from Kwara, former govnor of Akwa Ibom State, Godswill Akpabio, former Benue State governor, George Akume, Buhari campaign spokesperson, Festus Keyamo also dey. Di screening of di nominees go begin on Wednesday for Senate. 1. Chris Ngige 2. Hadi Sirika 3. Rotimi Amaechi 4. Festus Keyamo 5. Uche Ogah 6. Emeka Nwajuiba 7. Sadiya Farouk 8. Musa Bello 9. Babatunde Fashola 10. Godswill Akpabio 11. Sharon Ikeazor12. Ogbonnaya Onu13. Akpa Udo14. Adebayo (Ekiti)15. Timipre Sylva 16. Adamu Adamu 17. Lai Mohammed 18. Baba Shehuri (Borno)19. Isa Pantami20. Gbemi Saraki 21. Ramatu Tijani 22. Clement Abam23. George Akume 24. Sunday Dare25. Geofrey Onyeama 26. Tayo Alasaodura 27. Olorunminbe Mamora 28. Mohammed Abdullahi 29. Adamu Adamu 30. Maryam Katagun 31. Zainab Ahmed 32. Sabo Nano 33. Zubair Dada34. Paullen Tallen 35. Abubakar Aliyu 36. Sale Mamman 37. Abubakar Malami 38. Muhammed Mamood 39. Mohammed Adamu40. Rauf Aregbesola 41. Mustapha Buba Jedi Agba 42. Olamilekan Adegbite43. Mohammed Dangyadi https://www.bbc.com/pidgin/tori-49081268 +politics Update on Ghana election 2020: What John Mahama NDC tok afta Ghana election results final announcement "Leadership of de National Democratic Congress (NDC) say dem no go accept de results of de 2020 presidential elections which Ghana EC Chairperson, Jean Mensa announce. ""We reach de irresistible conclusion, say de election be flawed discredited election wey we reject de presidential result without any reservation,"" Haruna Iddrisu talk Ghanaians. ""As a party, we make extensive consultations den detailed analysis of de outcome of de elections wey Jean Mensa, the EC chair announce"" he add. According to de NDC, plenty evidence dey to show say John Dramani Mahama win de election. De National Democratic Congress (NDC) dey take decisions to challenge results of de presidential and parliamentary results. ""This evening Ghana's democracy has come under severe attack and needs some rescue urgently."" Incumbent leader, Nana Addo Dankwa Akufo-Addo win de 2020 General elections for Ghana after de country go de polls on Monday December 7. De NPP Candidate defeat en rival after he poll 51.59 percent of valid votes cast as against John Mahama of de NDC who poll 47.36 percent. In total, Akufo-Addo poll 6,730,413 votes whilst John Mahama secure 6,214,889 of de total votes cast." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55256123 +politics Zamfara state lawmaker speak on alleged 'threat to life' sake of say im no sign deputy govnor impeachment One lawmaker for Zamfara state north west Nigeria say im dey on di run for im life sake of say e refuse to sign di impeachment deputy govnor impeachment Hon Salihu Usman Zurmi na di only Peoples Democratic Party, PDP lawmaker for di Zamfara state Assembly, na im be di only pesin wey no sign di impeachment notice against di Deputy Govnor Mahdi Aliyu Gusau. Di lawmaker dey allege say im decision not to partake for di decision to impeach di deputy govnor don make am target for di state and say im life dey under threat because of im decision and na why e run away from di state. “I dey face serious threat to my life just because I no gree join oda members to impeach di deputy govnor and na why di state goment dey see me as K leg for dia plan. Dem feel say to catch or arrest me go allow dia plan to move without any problem, I strongly suspect say di goment dey behind di threats wey I dey face.” E tok. Hom. Salihu say im decision not to support di impeachment against Zamfara state deputy govnor na because of loyalty to im party. “I dey very loyal to my party and I also let di oda lawmakers know say wetin dem wan do dey wrong and make dem know say whatever you do pesin go return to you for future. Na because of my stance on dis mata I become target. Di goment dey see how I dey always dey against di plan on di floor of di house and dem fee say I dey stand in dia way.” E tok. Tok-tok pesin for Zamfara state Govnor Zailani Bappah tell BBC say wetin di lawmaker dey allege na notin but im own imagination as goment no get anytin against am or anybody for dat mata. “His excellency di govnor no dey put im hand for Assembly matas therefore no way e go interfere for dis mata talk more of threating any lawmaker life.” At di moment, di Assembly don already serve impeachment notice to di deputy govnor and im offence dem say include failure to discharge official duties and diversion of state funds. Na July of last year Zamfara state Govnor Bello Matawalle move to Nigeria ruling All Progressive Congress, APC from di opposition PDP but di deputy govnor no gree move with im boss and political analysts say na from dia im problems begin. Barrister Mahdi Aliyu Gusau for interview with BBC months afta di govnor decamp say e no go follow di govnor to APC as im mandate na to serve Zamfara pipo and e no dey fear impeachment. Shehu Bala na political commentator wey dey based in Zamfara state and e tell BBC Pidgin say wetin dey happun to di govnor na sometin wey many expect to happun even before now. “For Nigeria, no how wey govnor go decamp to anoda party and im deputy no go gree follow am and expect dem to remain togeda, dis na wetin dey happun for Zamfara.” In fact, if not for di influence of di deputy govnor father, dem for don comot am tay-tay but because General Aliyy Gusau na pesin wey Zamfara politicians dey respect na why Barrister Mahdi last dis long.” Di analyst say wetin dey happun na just politics and not really about offences as di Assembly dey claim. “Di 2023 elections dey close and alignments and re-alignments dey happun, di govnor dey try balance tins out before voting time so wetin dey happun for Zamfara na just politics.” E tok. Since Assembly serve di deputy govnor with di impeachment notice e neva comot to tok anytin ontop di mata. https://www.bbc.com/pidgin/tori-60373853 +politics Why PDP postpone 19 June Edo Govnorship primary election "Di National Working Committee of Nigeria main opposition party don shift di calendar date for dia govnorship primary election inside Edo state, southern Nigeria. Peoples Democratic Party (PDP) postpone date of di primary election from June 19 and 20, go June 23 and 24, meaning say dia own go happun afta di ruling APC party don do dia own primary for di 2020 govnorship election inside di state'. Chairman of PDP for Edo State Tony Aziegbemi say dem shift di date sake of wetin im call 'some political considerations. Im say so far di party get three aspirants for di primaries but dem dey ""expect di Edo state govnor Godwin Obaseki to join dem"" to make am four. Di national tok tok pesin of di party, Kola Ologbondiyan say dem bin first fix di date for di primary on 23 and 24 before dem move am go 19 June. Im say dem dem shift am go back so di party go fit do all di tins wey dem suppose do. Di Independent National Electoral Commission fix 27 June as deadline for all di parties to finish dia primaries. Obaseki resign im membership from di ruling All Progressive Congress party and so far, im neva register wit any oda party." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53099305 +politics Seun Fakorede: Di 27-year-old Oyo state commissioner nominee "As different state governors dey form dia cabinet, govnor of Oyo State, south west Nigeria Seyi Makinde, don also nominate di pipo wey im want serve for im cabinet. Part of di pipo wey im nominate na 27 year old engineer, Seun Fakorede. Di Speaker of di Oyo State House of Assembly, Adebo Ogundoyin confam di news for Twitter and since den, plenti pipo don dey share congratulatory messages not just to am but to di governor as dem say im dey put young pipo to dey involve in governance. Fakorede wey follow BBC Pidgin tok afta di news break, tok say im no expect di news at all as im no know di govnor of di state before. ""All di tins wey we don dey do for young pipo no be to get attention or political office and we dey do am for di love of di nation. We no lobby for am and na phone call wey we get come ask if I dey interested to serve my state. I feel good about am because na call to serve my pipo and na wetin I don dey do before but dis one na for larger scale. I feel very honoured."" E also dey confident say im go change how tins dey go for di state. ""Dis one go dey different as we don get di opportunity to serve. E go enhance di work wey we don dey do for (Home Advantage Africa). E go also be chance to show young pipo say dem dey capable to bring change. Dis one go also correct all di mess up way don follow young pipo before now and show say we change how tins dey go, Dis one na serious privilege to serve for Oyo State and I dey thankful say di govnor nominate me."" Seun Fakorede na di Founder and Executive Director of Home Advantage Africa; wey aim to change how pipo dey see Africa. E be graduate of Civil engineering from Obafemi Awolowo University wey dey Ile Ife, Osun State. He also be di co-founder and country manager of Boddiemax Online Premium Fashion Brand Fakorede na TedX Speaker and im don also work with di Lagos Development and Property Corporation (LSDPC). Im dey sit ontop different boards and im receive di Excellence in Service Award for 2017. Seun Fakorede dey confident say dis appointment go inspire young pipo across di kontri. ""Dis one go encourage and inspire young pipo to know say hard work still dey pay and no matter wetin you dey do, pipo dey watch you and before you know you go make am. Dem gats also know say success no dey come overnight and dis one no just happun as I don dey put in work for years.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-49412285 +politics US election: Donald Trump biography and what to know about di US president wey dey run for second term "Long before he show interest for US presidency, Donald Trump na America most famous and colourful billionaire. Wen he show interest to run for US presidency nobody believe am, nothing e do or get make am fit for dat position except for di fact say im be celebrity before-before. But di businessman defy all odds, beat politicians wey get plenty experience to win di ticket for di Republican primary race and e no stop for there, as he go ahead to win di presidential election wey be one of di most divisive and controversial contests in living memory against Democratic rival Hillary Clinton. Oga Trump na di fourth child of New York real estate tycoon Fred Trump. Even though im family get money, dem expect am to work for im papa company before dem send am go one military school at di age of 13 wen e begin dey misbehave for school. He attend Wharton School for di University of Pennsylvania and become di favourite to take over from im papa afta im senior brother Fred decide say na pilot im wan be. Fred Trump die for di age of 43 sake of alcohol, one incident wey im brother tok say make am run from alcohol and cigar all im life. Oga Trump say im start im real estate business wit shikini $1m loan from im papa before e join di company. He help manage im papa plenty housing projects for New York City boroughs, and later take control of di company - wey he rename di Trump Organization for 1971.Im papa die for 1999 and Trump for that time tok say. ""My papa na my inspiration,"" Oga Trump shift im family business from residential units for Brooklyn and Queens enta ogbonge Manhattan projects, e change di rundown Commodore Hotel into di Grand Hyatt and e build di most famous Trump property, di 68-storey Trump Tower for Fifth Avenue. Other properties wey im get na di: Oga Trump also develop hotels and casinos, one part of di business don make dem file case for four bankruptcy (for di businesses, no be personal bankruptcy). Mr Trump also build empire for di entertainment business. From 1996 until 2015, e dey part of those wey own Miss Universe, Miss USA, and Miss Teen USA beauty pageants. For 2003, he start one NBC reality television show called The Apprentice, wia contestants go dey compete to fit do management job for Trump organisation. He host di show for 14 seasons, and e tok say di network pay am a total of $213m. Oga Trump don write plenty books, and e get shop wey dey sell everything from neckties to bottled water. According to Forbes, im net worth na $3.7bn, although Trump don tok am plenty times say im worth $10bn. President Trump bin marry three times, im most famous wife na di first - Ivana Zelnickova, wey be Czech athlete and model. Di couple get three children togeda - Donald Jr, Ivanka and Eric - before dem file for divorce in 1990. He later marry one actress Marla Maples in 1993. They get one daughter named Tiffany together before dem divorce for 1999. He marry im current wife Melania Knauss, wey be model, in 2005, and di couple get one son, Barron William Trump. Di children from im first marriage dey help am run di Trump Organization now but na im still be di chief executive. Mr Trump show interest to run for president as early as 1987, and even enter di 2000 race as a Reform Party candidate. Afta 2008, he become one of di most outspoken members of di ""birther"" movement, wey question whether dem born Barack Obama born for America. Na June 2015 oga Trump formally announce say im dey come out to run di race for di White House. Under di banner Make America Great Again, Trump run controversial campaign wit promises to strengthen di American economy, build wall for di border of Mexico and di US, and to temporarily ban immigration by Muslims ""until di kontri representatives fit discover wetin dey happun. Oga Trump campaign for di presidency no dey easy including di emergence of one recording from 2005 wey show as im dey tok anyhow about women, and claims, even from members of im party, say im no dey fit for office. But im dey always tell im army of supporters say im go win. Afta he win di election, he and President Obama meet for transition talks two days afta di election day. Na im be di first president to enta office wit no experience for elected office or or don serve for di military, dis one mean say he don already make history before dem swear am in as America 45th president on 20 January 2017." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54750005 +politics List of possible replacement for Boris Johnson as UK prime minister "British Prime Minister Boris Johnson don announce say im go resign. Johnson agreeing to leave office mean say leadership election go hold to decide who go become di next Conservative leader and UK prime minister. Dem go however need to secure di support of Tory MPs, wit di final two candidates wey contest among Conservative members. Johnson bin dey fight to stay on for No 10 despite say im support dey collapse. So who be di potential candidates? BBC put togeda a list of possible replacement for Boris Johnson Rishi Sunak bin dey like di shining possibility for a future Conservative leader. But im image don dent in di last few months sake of one controversy over im wife tax affairs, and e no tey before dem fine am for breaching lockdown rules. E become member of parliament for 2015 -  for di North Yorkshire constituency of Richmond. Im early move to resign from di cabinet wit fellow minister and friend Sajid Javid be like action wey lead to di plenty ministerial resignations wey eventually force Boris Johnson out. Di foreign secretary follow for di pipo wey first declare her support for Johnson afta im chancellor and health secretary resign, wey make her dey among im among loyalists. As di only second woman to lead di Foreign Office, pipo hail her work  securing di release of Nazanin Zaghari-Ratcliffe after six years and for purnishing Russia and dia oligarchs. First elected in 2010 as MP for South West Norfolk, Ms Truss don become a popular figure among Conservative Party members for her liberal views on economics and trade. Na dis MP for Bromsgrove give di prime minister im first blow. Javid stress di need for integrity and telling MPs for im resignation speech say im don conclude: ""di problem start for di top"". For 2019 oga Javid bin contest to be leader of di party and e make am to di final four, before e withdraw to support Johnson. Na im decision make dem give am appointment as chancellor, but e resign afta six months afta e get problem wit im advisers. E then make a dramatic return to di front bench as health secretary in 2021. Born in Rochdale in 1969 to first generation Pakistani immigrant family and im father work as bus conductor. Javid pursue successful career for di City before becoming  Tory MP in 2010. Di former foreign secretary don remain as influential presence for Westminster from di backbenches since e come second to Boris Johnson for di 2019 leadership contest. E analyse goment policy throughout di pandemic as chairman of Commons Health Committee. Di son of admiral, Hunt make im money by setting up Hotcourses - a website wey connect prospective students wit educational institutions. MP for South West Surrey since 2005, Hunt joindi goment in 2010 as culture secretary and also lead di Department of Health. Di secretary wey dey stabilise tins don contest two times before for Tory leader and prime minister. For 2019 e come third to Boris Johnson and Jeremy Hunt. But im most popular intervention for leadership contest na for 2016, during di EU referendum, wen e be senior pesin on di Leave side. Di former BBC journalist and Times newspaper columnist na one of di longer-serving ministers for di cabinet. For 2010 e become education secretary and since den e don take up goment roles as chief whip, justice secretary, environment secretary and most recently levelling up secretary. Di current UK chancellor earn pipo trust wen e take up di role of vaccines minister during di pandemic, and pipo hail am for UK successful rollout. E say na ""di most important job I go ever do"" - although e later make am get am appointment education secretary. Born in Iraq in 1967, Zahawi and im family run from di kontri wen  Saddam Hussein take power. As a former assistant to a magician, Penny Mordaunt get track record of pulling off extraordinary feats. For politics, she already pull rabbit out of a hat for 2019, wen she make history by becoming UK first female defence secretary. Na position wey di former naval officer hold under David Cameron. MP for Portsmouth North since 2010, Ms Mordaunt na former head of di Conservative Party youth wing and press officer for William Hague wen be party leader. Tom Tugendhat na direct opposite of Boris Johnson. E be moderate wey dey preach pragmatism rather dan populism, sabi pesin wey support Remain for di 2016 EU referendum. For diz attributes, pipo begin see Tugendhat wey win election MP for Tonbridge in 2015 as a potential future leader of di Conservative Party for years. Di defence secretary and former soldier na low-profile figure wey don attract plenty attention since Russia invasion of Ukraine. Dat na wen di UK make early decision to support Kyiv wit weapons and training. Despite im opposition to Brexit, Wallace bin lead Boris Johnson unsuccessful 2017 leadership campaign, before e reward am wit cabinet post for 2019. He serve for Germany, Cyprus, Belize and Northern Ireland wia e e stop effot by IRA effort to carry out a bomb attack against British soldiers. Im na one of di main army personnel involved in recovering Princess Diana deadi body from Paris." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cv2xzmyz7g6o +politics Election, rule of law, details of wetin President Buhari tok for Liberia "Nigeria President Muhammadu Buhari visit Liberia on Tuesday to join di West Africa kontri to celebrate im 175th independence anniversary. Liberia gain independence from di United States for July 26, 1847 and e dey mark di celebration every year wit oda West African leaders in attendance. During di official celebration, President Buhari congratulate im Liberian counterpart on dis landmark achievement as democracy continue to thrive for di kontri. E also call on oda leaders for West Africa to do everything within dia powers to make sure say dem continue dis democratic process as dem conduct elections for dia kontri for atmosphere wia trust, freedom and transparency dey. President Buhari say dis na di only way di sub-region fit comot from di hand of unconstitutional take overs wey don already dey shake three kontris recently for di region. Di president also tok on democracy and good governance say e must take its roots for di African continent to sustain peace, stability and development as leaders must redouble dia efforts to guarantee say dem no turn back di hand of democracy. “I go like use di opportunity of dis event to address one important issue wey dey affect three kontris for di ECOWAS region; Liberia, Nigeria and Sierra Leone. “All di three nations get National Elections for 2023. ""For Nigeria, we dey work towards a free, fair, transparent, credible and acceptable outcome of elections and dia results, e dey important and necessary for all our kontris to key into dis resolves as dem dey indispensable to peace and stability in our kontris and sub-region. “Di deepening of democracy and good governance na ogbonge melecine to check-mate unconstitutional change of governments as we sadly witness within di last three years for three countries within our sub-region. We must strengthen our efforts to make sure say we noreverse   democracy for our sub-region and Africa,” im tok. President Buhari use di opportunity to tok about Nigeria leading roles wey pull di kontri back from im kasala for di 90s, e add am say im presence for di celebrations underscores im strong belief for cementing existing bilateral ties: “Nigeria contributions to di survival and safety of Liberia dey well known. ""Di dark period of your kontri civil war from 1989 to 1997, na period wey Nigeria invest hugely for peace for Liberia and indeed stability for di rest of di ECOWAS sub-region. May those dark days never re-surface in our kontris and sub-region.” Oga Buhari tok. Di Nigerian leader also commend im Liberian counterpart, Dr. George Manneh Weah, on how im show love for im kontri and how e take dey pursue peace, unity and progress. President Buhari say Nigeria go continue dey support Liberia. “Permit me to assure you and all Liberians say Nigeria, as a good partner and a dependable ally, go continue to support you, within di limit of our resources. “Dis also bring to di front, di need to strengthen and broaden di levels of collaboration and cooperation between our two kontris, both bilaterally and multilaterally, within di ECOWAS, AU and di UN, in order to adequately tackle di common national, sub-regional and global challenges.” E add am. President of Liberia, DR. George Weah say without di support of Nigeria, di kontri for no get peace as im thank di president Buhari say e show for di anniversary. Meanwhile Buharis visit to Liberia don cause so many tok -tok for di kontri social media as different tori dey comot as to why di Nigerian leader dey visist Liberia and wetin in wan go do for there." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw5ee00zeqro +politics Osun election: Buhari react as Ademola Adeleke defeat Oyetola to emerge govnor-elect "Nigeria President Muhammadu Buhari don congratulate di candidate of di opposition PDP party, Senator Ademola Adeleke, as im win Osun govnorship election. President Buhari say di election show wetin democracy really dey about, respect for di will of di pipo. Im hail di successful conduct of Osun election as a demonstration of di maturity and di commitment of all stakeholders, towards strengthening di integrity of di electoral process for Nigeria. Buhari add am say im dey fully committed to leave behind a legacy of credible elections for Nigeria. Ademola gbab four hundred and three thousand, three hundred and seventy one vote to lead im rival and present govnor of di state Gboyega Oyetola. ""Light don come to Osun"", dis na di reaction from presidential candidate of di People's Democratic Party, Atiku Abubakar. E congratulate di governor elect and also hail all di pipo wey come togeda to make di winning possible. ""Mostly dis na congratulations to di pipo of Osun state"", e tok. Former speaker of di Senate and PDP chieftain, Bukola Saraki say Oga Adeleke really understand di lessons from 2018- wen im first come out to contest- and work to build stronger coalition across di state and di kontri. Saraki say di party go copy dis winning strategy for di general election wey go happun for 2023. Adeleke, 62, poll 403,371 votes to defeat im closest rival and present govnor of di state Gboyega Oyetola wey poll 375,027 votes. Dis na di second time wey di two politicians go dey go head to head for election. Dem first meet for 2018 wen Oyetola defeat Adeleke afta Inec declare di election inconclusive sake of say di marging wey Adeleke take beat Oyetola no reach di numbers of votes wen dem bin cancel." https://www.bbc.com/pidgin/tori-62196117 +politics Edo Govnorship primary: Wetin we sabi about why APC disqualify Edo Govnor, Godwin Obaseki "Di ruling All Progressives Congress party, APC, for Nigeria don disqualify Edo state Governor, Godwin Obaseki from running in di 2020 Edo primary. APC Screening Committee for Edo State Governorship election on Friday declare say Govnor Godwin Obaseki dey unqualified to contest in di election sake of say some wuruwuru dey im education certificates and NYSC. Dem also two odas, Hon. Matthew Iduoroyekemwen and Egnr. Chris Ogiemwonyi. But di committee clear Pastor Osagie Ize- Iyamu, Dr. Pius Odubu and Hon. Osaro Obazee. Di screening committee bin announce di disqualification when dem present dia report to di Adams Oshiomhole-led National Working Committee for Abuja on Friday. Chairman of di panel, Prof. Jonathan Ayuba, explain say Govnor Obaseki dey disqualified because di committee no fit vouch for di authenticity of im Higher School Certificate wey e claim but no fit produce am. Di committee tok say di document wey e produce only show im attendance. Di seven-man screening committee tok say di report dey conclusive and na all members of the panel sign am. Oga Ayuba tok say di committee dey thorough for di process as dem record am and dem go make available di unedited recording to di party. Meanwhile, Govnor Obaseki don react. E say inm no go appeal di outcome of di screening process, as im dey seek re-election into office. For statement by im media aide, Crusoe Osagie, di govnor tok say e no need to file appeal as e be say na di National Chairman, Adams Oshiomhole start di move from di beginning. E tell im supporters make dem stay calm, wait for im further move. ""We don watch di mockery of democratic process, which Comrade Adams Oshiomhole, dey administer and superintending over in our great party di All Progressives Congress (APC). E don dey unfortunate, disheartening and dreadful spectacle"" ""We don initially know say going by di open display and enthronement of illegality by one man for di party wey comprise several organs and big big important pipo, there is no way that Governor Godwin Obaseki go get fair assessment for di run-up to di nomination of candidates wey go fly di flag of di party for di forthcoming Edo gubernatorial election"". Im tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-52999743 +politics Attahiru Jega: Why Jega ask Nigerians make dem no vote APC and PDP again Di former chairman of di Nigeria Independent National Electoral Commission, Prof. Attahiru Jega, don draw ear give Nigerians make dem comot hand from di ruling All Progressive Congress party and di opposition Peoples Democratic Party . Prof. Jega say dis na becos dem fail to do beta for di kontri inside di 20 years wey dem don dey for power. Inside exclusive interview wit BBC Hausa, Oga Jega say all di negative tins wey di parties bin do inside all those years na clear sign say kontri pipo no need to trust dem again or give dem anoda chance, cos notin go change. Im say: “APC and PDP don [rule], we sef don see am, dem no mean to repair tins.” “Check di fight against corruption, dem say all di pipo wey dem tok say dem be tiff, say dem go punish dem sake of dem steal under PDP, now dem don port go APC, and na silence you dey hear.” “Dat na why we tink say time don reach to create platform for all di good pipo to return to, to contribute to change Nigeria,” oga Jega tok. In also add say, “dat na why I already register wit di PRP as member make I see how I fit help Nigeria.” Oga Jega believe say corrupt pipo don block tins sotey, if you be good pesin and you dey dia party and you no fit do anytin, den a different party suppose dey wey go bring good pipo togeda. Prof Attahiru Jega na lecturer and one time vice-chancellor of Bayero University, Kano. Im na also di Inec chairman wey oversee di 2011 and 2015 Nigeria general elections. According to di university lecturer, “I don be university lecturer since 1979, forty years now, so wetin I don read and observe during my tenure as chairman of INEC, di way I see our politicians dey run di election and di way dem dey represent afta election dey really scary.” Im add say di palava wey Nigeria dey face na sake of lack of good governance, dis make some pipo dey call for di partition of di kontri. https://www.bbc.com/pidgin/58060905 +politics ‘No need to fear’ - Buhari react to Abuja terror alert Nigeria president say di US and UK advice to dia pipo no call for panic. President Muhammadu Buhari say di terror alert by di foreign kontris no mean say attack go happun. Di Nigeria leader reaction dey come as some kontri bin first issue terror alert say threat of terror attack dey for Abuja. Presido Buhari for statement wey im tok-tok pesin, Garba Shehu release on Friday say im don charge security operatives to dey alert since afta di attack on Kuje prison. “No be only Nigeria dey di list of terror threats by foreign goment travel advice to to dia citizens. UK and US travel advisories also tok of  terror attacks wey fit happun for many Western European nations. “However, e no mean say attack go happun for Abuja,” di statement tok. Nigeria security agencies deny tori say dem carry out joint operation wit foreign forces for Abuja, di Federal Capital Territory. Di Department of State Services (DSS) tell BBC Pidgin say dem no carry out any joint operation wit US forces. Di clarification from DSS come as tori come out say security for Nigeria collabo wit US navy seal to raid one Trademore Estate, Abuja. Di tori wey local media cari tok say di raid bin happun on Monday for di estate wia joint security forces arrest some suspects wit improvised explosive devices. Dem say di ‘sting operation’ na to bust planned attack by a group of pipo wey di security arrest. Eyewitnesses say na on Monday night di operation happun and security lock evribody inside di estate while di operation dey go on. Di tori come at a time wen di United States and di United Kingdom Embassies issue terror alert for dia citizens. Di alert don cause panic for many residents of di federal capital. Peter Afunaya, tok-tok pesin to give clarity weda dem carry out operation or not. “No such ops in Abuja between DSS and any oda kontri military”, e tok. One shopping for Jabi district of di federal capital territory bin close shop sake of security reasons. Di closure of Jabi Lake Mall come days afta US warning about terror alert for Abuja. Di management of di mall for statement dem release on dia official later announce say dem don re-open afta “re-assurances from di Federal goment, heads of security agencies and FCT Minister.” Initially di company bin say dem dey monitor di security situation. On Friday di management though dem still dey monitor di security situation, “cente management go implement security measures to ensure evri body safety and maintain di highest vigilance.” One of di main opposition parties wey wan contest di 2023 election, Labour Party inaugurate dia presidential campaign council today. Di presidential candidate, Peter Obi and im vice, Ahmed Baba Datti no attend di event wey hold for Abuja. Director-General of di Council oga Doyin Okupe tell party members say dia candidate and im vice no come sake of security advise dem get. “I wan tell un say di presidential candidate and di vice presidential candidate no dey here based on di advice by our security team,” Okupe tok. Afta di attack on Kuje prison for Abuja for August, security threat bin comot again say terrorist plan to attack schools for FCT. To make pipo dey on alert, di Inspector-General of Police Usman Alkali Baba order security to protect all schools, hospitals, health workers and critical national infrastructures around di kontri. BBC Pidgin torchlight 15 safety tips wey police want make you know. Tip 1. No use car stickers wey tok wia you dey work, especially if na ogbonge job. Tip 2. No post pictures of your pikin for dia school uniforms or badges, protect una pikin. Tip 3. Wen you go party, no let di band jazz you sotay you start to dey spray money, use envelope. Tip 4. No be di pesin wey go try empty ATM machine with large withdrawal. You no need 50k for wallet to feel like man. Tip 5. Always delete bank transaction notification especially SMS… you fit memorize your bank balance. Tear your POS/ATM receipt troway. Tip 6. No jog wey da don dark, you suppose get sense pass that. If you fit carry pesin wey you trust follow bodi. Tip 7. Always lock your doors, even if na just to waka outside to off gen. Tip 8. Never-never-never ear your ID outside your work place. No bodi need to know wia you dey work. Tip 9. Dey accountable with your parent or your spouse, make pesin know wia you dey at every point. Tip 10. If you fitm no dey send pikin alone on errand outside your house, dem be soft targets. Tip 11. No dey form big oga for your street with plenti donation for estate meeting, try dey modest. Tip 12. Wen you dey give, give modestly and for private, try dey tok “I no fit spare dat kain money now”. Tip 13. No too stay for office afta closing time, you fit do dat deadline work later or for house sef. Tip 14. Make safety di number one tin you dey tink for your decisions always. Tip 15. Mind wetin you dey post for social media about yourself. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyxy99xqj2jo +politics Osun state governorship election result Live updates PDP candidate, Senator Ademola Adeleke na im still dey take di lead for di Osun govnorship election as INEC dey collate result. So far, e dey lead for 17 out of di 30 local goment results wey di Independent national electoral commission don announce. Di pipo of Osun State for southwest Nigeria on 16 July, 2022 enta polling units to vote for dia next govnor. Di election see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991. Na fifteen candidates dey di race to become di next govnor of di South Western state. Na Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC go announce di winner of di election. According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast. Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election). Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions. Continue to dey refresh di page to get di results as Inec begin dey drop am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-62195431 +politics Bayelsa house of assembly 'lawmakers' say dem don impeach di speaker "Drama dey for di Bayelsa State House of Assembly for Southern Nigeria as one faction of di lawmakers dia say dem don impeach di speaker Tonye Isenah. Radio Nigeria tori pesin Alambo Datonye tell BBC Pidgin say gunshots begin fly upandan for di assembly complex after di Speaker Isenah don comot, di Deputy Speaker, Abraham Ingobere call for anoda sitting and Bernard Kenebai, di member wey dey represent Sagbama Constituency two move motion to impeach di speaker with support from voice vote by 16 members wey dey present. Den member wey dey represent Yenegoa constituency one Oforji Oboku come move motion to elect Monday Obolo wey dey represent Southern Ijaw constituency two. Dis wan dey come afta tori bin full ground on Monday morning say di speaker go step down from di position, but dat one no happun as Isenah tell BBC Pidgin say im no resign. Isenah tell BBC Pidgin say im na di duly elected member of di house and nobody get right to tell am to resign position wey pipo vote am into. ""I never resign. Di expectation na say I suppose come plenary dis morning to resign. I be elected member and dat na arm of goment, distinct arm of goment wey suppose dey respected. I never commit any crime so I no see any reason why I go resign."" "" I preside over di house and adjourn di house sine die and e stand adjourned. Na only me wey get di right to reconvene di house again but information wey dey reach me be say some members go smuggle anoda mace and dem dey seat. Dem dey seat wen I don adjourn di house and no body fit reconvene again so dat one na illegality."" Meanwhile Monday Obolo wey dem elect to replace Isenah don tell tori pipo say ""wetin don play out na democracy in action."" E never clear wetin cause dis gbege but tori be say pressure from some party chieftains for di Peoples Democratic Party PDP dey Press Isenah to step down as Speaker, as Sen. Douye Diri wey be di governorship Candidate for di Party come from Kolokuma/Opokuma local goment and Isenah too also come from di same local goment area too." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49885120 +politics Ekiti election: INEC do's and don'ts on voting day Pipo for Ekiti state southwest Nigeria go comot on Saturday, 18 June 2022 to vote a new govnor wey go lead di state for di next four years. Election joinbodi di Independent National Electoral Commission say dem don ready for di election and dia materials and personnel don dey ground already. Na 16 local goment areas dey Ekiti state wit 177 wards and 2,455 polling units wia election go happun. INEC say di number of registered voters na 988,923. Di election umpire say na four National Commissioners and eight Resident Electoral Commissioners dem deploy to ensure di conduct of a credible election. Na 734,746 voters don collect dia Permanent Voter Cards (PVCs). Dis na some of di rules and regulations wey dey guide elections for Nigeria and go apply for dis election as INEC tok. Sabi pipo say di race na between three parties; di PDP, APC and SDP. Already, some of di 16 candidates wey dey participate for di election join hand sign peace accord ahead of di election. Security don also already dey tight for di state capital as plenti security vans and teams dey patrol di town. https://www.bbc.com/pidgin/tori-61837328 +politics Edo election update: Nine rules voters must obey during 19 Sept. governorship election - IGP Edo State go vote in dia next govnor on 19 September so to make sure e go smoothly, Nigeria Police and stakeholders for di election process bin meet on Wednesday. Di police set at least nine rules wey dem put for ground wey include no jolly for polling booth and di ban of shayo sale near di voting centers. For dis election, Gov. Godwin Obaseki dey contest for second term in office. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54144598 +politics Africa political dynasties: How presidents dey groom dia sons to takeover power "Congo-Brazzaville President Denis Sassou-Nguesso don appoint im son Denis-Christel as cabinet minister - wey don make pipo begin reason am say im wan run am like family dynasty. No be say any type of handover don near. Sign no dey say di 77-year old head of state wan comot seat of power, now wey dem just elect am for fresh term for March, and done rule for many decades. Yet if Denis-Christel come enta power after im papa comot, dis one go confam di format wey don dey dey popular for Central Africa. For neighbouring Gabon President Ali Bongo Ondimba na di son of Omar Bongo, wey rule from 1967 to 2009, while for Democratic Republic of Congo Joseph Kabila rule for 17 years after im takeover for 2001 when dem assassinate im papa Laurent-Désiré as head of state. Equatorial Guinea President Teodoro Obiang - wey comot im own uncle Francisco Macías Nguema as di kontri first head of state, for 1979 - don already appoint im son, Teodoro Nguema Obiang Mangue, as vice-president, to make am easy for am to takeover. And after Chad President Idriss Déby die last month - from wetin goment say na injury from war front - im son Mahamat, wey be four-star army general, don sharpaly rise to be di leader of di interim ruling military council. And now underground tok-tok don dey dey say Cameroon sef fit see dis kain family format. Dis na afta one anonymous ""citizens' movement"" campaign begin for Franck Biya, di son of di 88-year-old President Paul Biya wey never even reach middle of im new seven-year term. Sources wey dey close to Franck - even if im no dey chook hand for politics, as e prefer private sector business career - don torchlight say Franck no get anytin to do wit di campaign wey dey promote im name. But also, im never tell dem to stop, and e never comot public statement say im no get am for mind to succeed im papa. Of course, political dynasties no be new tin - see for example di Bush and Kennedy family for di US. And currently for Uganda, one social media campaign dey package General Muhoozi Kainerugaba, son of current head of state Yoweri Museveni, as di potential ruling party candidate for di next election in 2026. But dis pattern of leaders wey dey hand power to dia pikin dey common pass for west-central Africa economies wey depend on oil, as di money from oil dey ginger di politics dia. E dey also cause rivalries and and katakata inside di ruling dynasties. Rumours dey say inside di Obiang family fight-fight don dey happen, as tori be say some family members dey favour anoda son of di president, Oil Minister Gabriel Mbega Obiang Lima. But di phenomenon dey particularly entrenched in west-central Africa's petro-economies, wia oil revenues often lubricate di networks of political patronage and empire-building. It dey also fuel rivalries and resentments within ruling dynasties and dia often complex webs of personal connection. Rumours of palace intrigue dey among di Obiangs, wit some family members said to dey favour alternative presidential son, Oil Minister Gabriel Mbega Obiang Lima. But no be just about personal issues. Ali Bongo face former foreign minister and African Union Commission chief Jean Ping, inside di 2016 Gabonese election. Meanwhile Ping na di former partner to di president sister Pascaline, wey go make president Ali Bongo uncle to dia two children. Five years after di elections, Ping no gree for di defeat as serious kwesions comot about whether di polls dey free and fair. French justice don dey torchlight Equatorial Guinea regime for allegations say dem bring enter France family assets wey dem use corruption money buy. Di Bongo and di Nguesso na im French authorities dey targe: di 13 pipo wey dem open formal investigation ontop dia head also include one lawyer wey work for di President Omar. For 2015 French judges order say make dem seize two properties for Paris wey dem believe di real own na Sassou-Nguesso nephew Wilfrid Nguesso; not to mention 15 luxury cars dem seize join. Wilfrid dey under formal investigation. Then by middle of 2017 - one year after Nguesso say make France troway di case against am - French authorities put di president daughter Julienne and her husband Guy Johnson, anoda nephew, Edgar, and one former sister-in-law, Catherine Ignanga, under formal investigation. Di matter relate to $22.4m of money transfer dem allege say dey suspicious, wey happen between 2008-2009. But na Equatorial Guinean Vice-President, Teodoro, attract attention pass, with police wey don raid im luxury house since like 2012 and seize plenty cars, including two Bugatti Veyrons and one Rolls Royce Phantom. Dem later sentence Teodoro order am to pay €30m fine. Im goment International Court of Justice, wia dem argue say di Avenue Foch mansion, wey worth €107m, na dia embassy for France and so e get diplomatic immunity. But, last December the Court reject di argument. Even though for some countries di recent trend na for presidents to want put dia family members for power after dem don comot, e no dey clear whether dis pattern fit last. Dis na because African population dey young more and more and dia expections of dia goments don dey change. Paul Melly na Consulting Fellow with di Africa Programme for Chatham House in London." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57300850 +sports Timo Werner: Di new Chelsea signing score during RB Leipzig vs Düsseldorf - See oda five record-breaking goals of di footballer "Chelsea don agree to sign German professional football player wey dey play as RB Leipzig striker, Timo Werner on a five-year deal Di forward, 24, don agree on personal terms with di Blues afta im pass im medicals , im go join in July afta di German league season ends. Werner, who join Leipzig from Stuttgart in 2016, don score 32 goals in all competitions so far dis season. Di new Chelsea signing score during RB Leipzig vs Düsseldorf wey happun on Wednesday 17 June, 2020. On Thursday Timo Werner take to Twiterr wia di striker tok say im dey happy to for im signing to join Chelsea ""I dey look forward to next season with my new team-mates, my new manager and of course di Chelsea fans."" For im 200 Bundesliga games , Werner find the back of the net 75 times, and im dey score on di average of every 185 minutes - di rate wey dey similar to dat of im Germany predecessor Miroslav Klose. In 2019/20 season alone im get 32 goals in as many games at di start of di season, wey include di first two hat-tricks of im blossoming career, against Borussia Mönchengladbach and Mainz. With Goals for di UEFA Nations League and Euro qualifiers, as well as nine for 16 UEFA Champions League and Europa League games for Leipzig, don help Werner seal im place for di international spotlight." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53096427 +sports Ghana beat Nicaragua 1 - 0 inside World Cup friendly Ghanaian national team side, Black Stars beat Nicaragua by one goal to nil inside dia friendly match ahead of Fifa 2022 World Cup tournament for Qatar. De Black stars start de game slowly as dem fail to create chances, but dis change in de 35th minute when Fatahu Issahaku convert long range strike into goal. Dis be de only goal wey seperate de two teams and de end of 90 minutes of de game as Nicaragua fail to hit de net. Coach Otto Addo change de line up of de Black Stars against Brazil wia dem lose 3 - 0. Atletic Bibao player Inaki Williams start de game for de Black Stars, with support from Mohammed Kudus. In de absence of midfielder Thomas Partey who pick up injury before de last game, Daniel Kofi Kyere step up for de Black Stars as he draw plenty fouls den hold de midfield. Despite having a good game in de second half, striker Inaki William no see more of de ball in de first half as he no get passes. Former Black Stars strike Asamoah Gyan criticize de players over dia failure to serve passes. Black Stars go face dia third and final World Cup friendly on November 17 Switzerland. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz7dkjex9zwo +sports Nketiah, Hudson-Odoi, Lamptey and other players Ghana dey pursue for 2022 Fifa World Cup squad "In November 2022, Ghana go be one of de 32 countries who go participate in de Fifa World Cup tournament for Qatar. Ghana despite crashing out of de Afcon 2021 tournament during de group stages, beat rivals Nigeria in de Third-leg of de World Cup Qualifiers to book dia place. Dis go be de fourth appearance of de Black Stars for de World Cup competition after dem feature in 2006, 2010 den 2014. New technical team led by Coach Otto Addo den Chris Hughton manage book de Black Stars a spot in de World Cup against all de odds, de Ghana Football Association now dey scout around for players who go fit help beef up de Black Stars squad. Sake of dis, some Ghanaian footballers who dey play for foreign countries sake of dem get roots from di West African country dey on de GFA list for possible call ups. Dis be some of de players wey GFA give indications say dem dey go after ahead of de tournament. One of de key players wey dey on GFA radar for de Black Stars be Brighton, Holve and Alvion right-back, Tariq Lamptey. Recent reports dis week from BBC Sport be say England Under-21 head coach, Lee Carsley say de 21-year-old defender request say make dem leave am out of de Under 21 squad. ""He request say make we leave am out of de squad small make he think"" Lee Carsley talk. Lee Carsley explain say Ghana approach Tariq Lamptey, wey be like he dey ""consider"" de offer. Recently, Tariq Lamptey visit Ghana wit en family after de end of de English Premier League. He talk to local media say he dey Ghana for ""some sun and family time."" During en visit, he take time off de wtach de Black Stars game against Madagascar. Ghana Football Association start dey pursue de London-born defender since around 2020, but football pundits say de World Cup be major encouragement for de lad to join de Black Stars. Lamptey, get two Under-21 caps dey qualify for Ghana through en parents. Another player wey dey top on de list for Ghana be Chelsea and England winger, Callum Hudson-Odoi. Ghana President, Nana Akufo-Addo make personal call on de player to switch nationality den join de Black Stars. Inside twitter post last year, Prez Akufo-Addo write say ""Ghanaian-born Chelsea footballer, Callum Hudson-Odoi, pay courtesy call on me for Jubilee House, de seat of wana presidency."" ""Amongst others, I advise de Minister for Youth and Sports say make he explore de possibility of having Callum switch nationality, den play for de Black Stars. Odoi en switch to Ghana be possible sake of en parents be Ghanaian, dem born am for Ghana until he later later acquire British citizenship. He make three appearances for de Three Lions and several others in the England U21. According to Hudson-Odoi, ""the thing obviously say I go choose Ghana or England, at de end of de day I said I always have de right people around me who always advise me - what be right, what be wrong."" ""England come wey I say yeah, let me go and play for my country. But I talk say Ghana be my home as well, so we go see, we go see. You never know..."" he talk on Accra-based Joy FM. Despite say he play three times for de Three Lions of England, as per Fifa rules, he go fit switch nationality to Ghana so far as he no play more than three senior matches for England. Also, one go fit switch to different nationality three years after de last international appearance. Dis mean say Hudson-Odoi go fit make dat switch next year November, before 2022 World Cup go start. Eddie Nketiah be London born footballer who dey play forward for Arsenal, but de young lad be eligible to play for both England and Ghana. Dis be sake of en parents be Ghanaians but dem born am in England so he get British citizenship.In 2017, Nketiah get en first international call to play for England Under 18 level, wey he later play for Under 19. In October 2020, Nketiah become England U21's all-time leading goalscorer after he broke Alan Shearer record. De Ghana Football Association (GFA) make efforts over de past few years so say Nketiah go switch to Ghana but so far e no clear yet what en decision go be. Recently, unconfirmed reports start dey circulate say de player secure Ghanaian passport, although he no personally confirm or deny de claims, he mention say he go like focus on de future of en club football first before national football. Per Fifa rules on switch of nationality, players according to Article 8 who wan change national teams for formally request a change from Fifa. Fifa then go review dia case on de Players Status Committee.But sake of Eddie Nketiah no play for England yet at for de senior level, de process go be more straightforward for de 22-year-old. Athletic Bilbao attacking duo Inaki Williams den en brother Nico Williams currently dey Ghana for family vacation. But pundits say de players go meet GFA officials for discussions which go focus on lobbying for dem to join de senior national team. Last year when question about playing for Ghana pop up, Inaki Williams talk say he dey see himself more Spanish than Ghanaian sake of dem born am there. Pundits however dey talk say things change since and de possibility dey for at least one of den, Nico Williams especially to join de Black Stars if dem choose to represent Ghana. In order for a player to switch allegiance den represent a new country, Fifa set out procedure wey interested parties for follow. Dis be what dem for do Submission of a request by the new association After gathering all de mandatory documents from de player, de new association go take responsibility for submitting, on behalf of de player. Review by de FIFA general secretariat Upon receipt by de FIFA general secretariat, dem go assign de case to a handler who go be responsible for reviewing de information and de documentation dem submit. Decision by de Players’ Status Committee Upon receipt of de request, one or more members of de Players’ Status Committee go analyse de case and inform de FIFA general secretariat of dema decision. Terms of decision of de Players’ Status Committee Once dem inform FIFA general secretariat of de decision of dee member(s) of de Players’ Status Committee, de terms of de decision will be legally notified to de association(s) concerned by email. De terms of de decision go state whether de request be “accepted”, “rejected” or “not admissible”. Grounds of de decision of the Players’ Status Committee De association(s) concerned get ten days from de date of notification of de terms of de decision to request de grounds of de decision. Failure to do so go result in de decision becoming final den binding. Appeal to de Court of Arbitration for Sport According to art. 58 par. 1 of de FIFA Statutes (September 2020 edition), de decision of de Players’ Status Committee may be appealed before de Court of Arbitration for Sport (CAS) within 21 days of de notification of de grounds of de decision." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd1n74vxvrno +sports Kelechi Iheanacho: Poland border control bar Nigerian, striker go miss Europa League tie against Legia Warsaw "Leicester City don rue out Kelechi Iheanacho from dia match against Legia Warsaw after Poland border control no allow am enter dia kontri. Di striker bin travel to Warsaw with Leicester City but problem wey border control notice with e travel documents na why dem no allow am into di country. ""We don get small issue wit Kelechi. Im document coming into di kontri bin no dey sufficient, so im bin no dey able to travel"" na so e club coach Brendan Rodgers tok. ""Di paperwork no allow am enter di kontri. We go look into am wen we return"". Leicester City face Legia Warsaw on Thursday but now dem go play di match without di Nigeria international. Iheanacho bin score 19 goals for Leicester City last season, but go now return to di UK. Im fellow Nigerian, Wilfred Ndidi go also miss di match because of suspension. Ndidi bin collect red card for dia opening group match against Napoli wey dem draw 2-2. Di Foxes don dey inconsistent throughout dis season, Jamie Vardy two goals rescue Premier League home draw against Burnley on Saturday to leave dem with seven points from six games." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58744891 +sports Atletico Madrid beat Real Valladolid 2-1 to win La Liga title Atletico Madrid na di new champions of di 2020/2021 La Liga season. Going into di final La Liga matchday against Real Valladolid, Atletico bin need to avoid defeat to collect di crown as champions of La Liga. Despite say Real Valladolid bin score first, Atleti rally for di second half wit goals from Angel Correa and Luis Suarez to win di game 2-1. Dis na Atletico first league title in seven years and na dia 11th overall. Atletico finish just two points ahead of defending champions Real Madrid, wey end di season without any silverware. Wit only one game left before di season go end, Atletico bin dey top of di table wit 83 points, two points ahead of Real Madrid for La Liga table. Atleti bin need to win away at Valladolid as dem no get better head-to-head record wit Real Madrid if to say dem draw and Madrid beat Villarreal. Diego Simeone side bin fall behind to Oscar Plano strike but dem turn di match around for di second half through goals from Angel Correa and Luis Suarez. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57214688 +sports Wetin you need know ahead of Uefa champions league draw Top football clubs for Europe go know dia opponents on Thursday. Dis na as UEFA Schedule to hold di Champions league draw for di 68th season of Europe biggest club football competition and di 31st since dem rename am di Uefa champions league. Preliminary games for di top league end on Wednesday – dis one open way for Uefa to do di draws as all di teams don complete. Di Champions League 2022-23 group stage draw go hold for Istanbul, Turkey. Officially di competition go start on 6 and 7 September and end on 10 June 2023, according to di organisers. Di Uefa champions league draw go hold by 1700 GMT (5pm CAT). Pot 1 Real Madrid Eintracht Frankfurt Manchester City AC Milan Bayern Munich PSG Porto Ajax Pot 2 Liverpool Chelsea Barcelona Juventus Atletico Madrid Sevilla RB Leipzig Tottenham Pot 3 Borussia Dortmund RB Salzburg Shakhtar Donetsk Inter Milan Napoli Sporting Lisbon Bayern Leverkusen Olympic Marseille Pot 4 Club Brugge Celtic Maccabi Haifa Copenhagen Dinamo Zagreb Viktoria Plzen Rangers Benfica Di final of di 2022/23 Uefa champions league go hold for di Atatürk Olympic Stadium for Istanbul, Turkey. Di venue dey popular for im name, 'Miracle of Istanbul'- afta  Liverpool beat AC Milan for di 2005 final of di champions league. Liverpool come from three goals down to equalise and dem beat Milan for Istanbul. Na Istanbul suppose host di 2020 final of di champions league but e no hold sake of di Covid-19 pandemic – di final eventually hold for Lisbon, Portugal dat year. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c98jqlxd0q2o +sports Coronavirus: Di Chelsea football star wey dey buy masks for Sierra Leone traders Chelsea footballer Antonio Rüdiger don launch campaign to raise money to buy face masks for market traders wey dey Sierra Leone.Rüdiger says im dey hope say di mask go help protect them and stop di spread of coronavirus. He tweet say im foundation go partner with Mary-Ann Kaikai of Madam Wokie Fashion and di charity Lunchbox Gift to provide 60,000 face masks: Rüdiger, wey dem born to Sierra Leonean parents for Germany, also bring in fellow Premier League players, who don set di ball rolling for di campaign to raise $30,000 (£24,000).He even thank Mesut Özil, N'Golo Kanté, Callum Hudson-Odoi and Olivier Giroud for dia support: https://www.bbc.com/pidgin/52359246 +sports Coronavirus: La Liga don dey suspended as dey quarantine Real Madrid squad "Uefa don call emergency meeting for Tuesday wia dem go discuss di possibility of postponing Euro 2020 by one year. European football governing body go hold video conference meetings to discuss dia response to di coronavirus outbreak. Discussions go cover all domestic and European competitions, including Euro 2020. Euro 2020 suppose take place from 12 June-12 July for venues all ova Europe. Uefa don invite representatives of dia 55 member associations, plus di boards of di European Club Association, di European leagues and representative of world player union Fifpro. Meanwhile, dem don postpone di second leg of Manchester City last-16 second leg Champions League tie against Real Madrid, wey dem wan play on Tuesday 17 March. La Liga don also suspend dia league for at least di next two rounds of matches"" sake of say dem quarantine Real Madrid squad because of coronavirus. In addition, Danish Football Association don cancel all football activities for di kontri for two weeks while di Netherlands' Eredivisie don dey suspended until 31 March. For Italy, Serie A dey suspended until 3 April, and di kontri dey on lockdown. Two players - Juventus' Daniele Rugani and Sampdoria's Manolo Gabbiadini - test positive to coronavirus." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51855134 +sports Southampton vs Man United: Red devils drop points for dia first away match dis season Manchester United play 1-1 draw wit Southampton for Premier League on Sunday. Na Southampton first score for di match afta dem Jack Stephens collect di ball from Bruno Fernandes and play low cross to the edge of di box. Na dia Adam Armstrong give Che Adams pass wey him wire hot shot wey touch Fred enta inside di goal. United try but dem no fit find di break through until afta half time. For second half Manchester United put pressure for Southampton defence and finally dem find break through. Mason Greenwood score di equalising goal, but na Paul Pogba do all di hard work. Na another assist for di Frenchman wey dribble inside di box and plays one clever one-two wit Bruno Fernandes before im find Greenwood on di edge of di box. Di 19 year old hits am first time and e pass through di legs of Mohammed Salisu and pass di reach of Alex McCarthy. Dis result mean say afta two games Manchester United dey fourth for table while Southampton dey 13 position. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58299734 +sports Black Stars Thomas Agyepong go miss next match, Andre Ayew appearance be fifty-fifty "Black Stars captain, Andre Ayew den Thomas Agyepong miss de team recovery training on Wednesday after dema 2-2 draw plus Benin. Dem reveal from camp sey medical test reveal sey Agyepong no go fit make de line up in dema against Cameroon, meanwhile Dede Ayew en own be fifty-fifty. Black Stars Media officer and NC Spokesperson, Dan Kwaku Yeboah reveal for statement inside sey ""de medical team dey monitoring Dede en condition wey dem go advise de technical team on en availability depending on how he respond to treatment."" Pictures from dema training session dey show sey Captain Andre Ayew dey tap bench whilst de training dey go on. De squad start dey train Wednesday evening for de Suez Canal Complex ahead of dema next game on Saturday. But de two players tap bench throughout de training session sake of dem all pick up injuries during de first game against Benin. Thomas Agyepong pick en injury around de first half of de game wey dem substitute am, wey Andre Ayew suffer one bad attack during de second half so as de game finish den he dey limp. Black Stars go face de Indomitable lions of Cameroun at de Ismailia Stadium on Saturday, 29 June, 5pm." https://www.bbc.com/pidgin/sport-48796956 +sports """Portugal vs Spain"", oda international friendlies matches on Wednesday and how to watch dem" International friendly matches go begin dis evening (Wednesday), and some of di biggest football players for di world go represent dia kontries. Cristiano Ronaldo Portugal go face Spain for Estadio Jose Alvalade stadium for Lisbon.for one of di star matches of di day. Moral high well-well for Portugal and Spain team afta dia victory last month for Uefa Nations League. Luis Enrique team wipe Ukraine 4-0 and play 1- draw wit Germany while Portugal beat Sweden and Croatia. Portugal victory against Croatia strectch dia unbeaten home record for competitive fixtures to six years. Meanwhile di last two times wey Portugal don play Spain na for major tournament, for 2018 World Cup for di group stage dat game end for 3-3 draw. And di oda time dem face each oda na for Euro 2012 semi-final di game end 0-0. Check out di fixtures dem here Germany vs Turkey Italy vs Moldova Denmark vs Faroe Islands France vs Ukraine Portugal vs Spain Netherlands vs Mexico Armenia vs Albania Na cable company Dstv go show di matches live for Nigeria. So you watch di matches live for dia sport channels. https://www.bbc.com/pidgin/sport-54452579 +sports Real Madrid vs Barcelona: Aubameyang score twice for El Clasico to give Barcelon 4-0 win over Real Madrid La Liga league leaders Real Madrid suffer heavy 4-0 defeat from di hands of rivals Barcelona for El Clasico. Pierre-Emerick Aubameyang score twice while goals from Ronald Araujo and Ferran Torres condemn Madrid to dia heaviest home defeat of dis La Liga season. Di result no get much impact on di race to win La Liga but e show how far Barcelona don come since dem appoint dia former player Xavi earlier dis season. Real Madrid bin don beat Barcelona twice dis season for league and for di Supercopa de Espana but dem look shadow of demsef without dia talisman Karim Benzema as Barcelona run riot for dia backyard. First Aubameyang open di scoring wen im head home Dembele cross on 29 minutes. Di Catalans quickly double dia lead as Araujo jump high to head in anoda Dembele cross from cornerkick for 2-0. Then Torres finish off good move early in di second half before Aubameyang score im second of di night for im first El Clasico appearance on 53 minutes. Real Madrid go still remain top of La Liga wit 66 points, nine ahead of Sevilla wey dey second but dem no go happy to lose like dis to dia greatest rivals. For Barcelona, dia run of form continue as dem don climb back to third position, equal on 54 points wit Atletico although Barca still get game in hand. 46 mins - Substitutions Camavinga don replace Toni Kroos while Diaz come on for Carvajal. Straight from di restart Barcelona bin get opportunity to increase dia lead but Ferran Torres shoot wide. 48 mins - Goal for Barcelona! E no take long Barcelona don increase dia lead. Aubameyang back heel pass to Torres wey shoot first time past Courtois. 51 mins - Looks like Barcelona don score again. Aubameyang don grab im second of di night afta long delay to confirm from VAR. 53 mins - Goal given! Di referee don award di goal to Barcelona. Dis no be joke. Real Madrid 0-4 Barcelona 56 mins - Real players dey look like say dem see ghosts as dem dey sbocked by di scoreline. Meanwhile Barca players look like say dem want more goals. 59 mins - Aubameyang almost score hat-trick but im stretched leg wey connect wit Torres cross no direct di ball to dey on target. Di Ganon striker dey enjoy life for Barcelona. 63 mins - Yellow card for Luka Modric. Real Madrid bring on Asension and Vazquez for Rodrygo and Nacho. 66 mins - Casemiro try im luck from outside di box. Im shot no trouble Ter Stegen wey watch as di ball go wide. 71 mins - Substitutions No hat-trick for Aubameyang today as coach Xavi don sub am. Auba and De Jong don come off, Depay and Gavi na im replace dem. 74 mins - Jordi Alba collect Yellow card as im bring down Vinicius wey bin no dey happy wit di foul. 77 mins - Real Madrid get less dan fifteen minutes to find consolation goal for dis match. Asensio just shoot wide. Dat na Real first shot for dis second half. 78 mins - Madrid goalkeeper Thibaut Courtois don dey very busy for dis match, dis time im save Depay shot. 79 mins - From dat Barcelona attack, Madrid create dia own chance. Alaba test Ter Stegen wit hot shot wey di German save. 80 mins - Substitution Xavi don send on Adama Traore for Ousmane Dembele. 82 mins - Camavinga don enta di referee notebook as im receive Yellow card for foul on Busquets. 86 mins - Substitutions Pedri and Alba OFF, Dani Alves and Nico ON for Barcelona. 88 mins - Lucas Vazquez recieve Yellow card for back-to-back foul on Barca players. Nico also collect Yellow for wetin im tell ref. Full time - Real Madrid 0-4 Barcelona 1 min - Barcelona take di first kick as di match don start. Immediately Militao foul Ferran Torres. Nothing come out of di freekick to trouble Real Madrid. 5 mins - Federico Valverde break free inside Barca half come pass di ball give Rodrygo. Di Brazilian shot hit di side netting. Di fans be like say den ready well well for di match as dem dey cheer and shout about every good play so far. 7 mins - Save! Vinicius Junior dribble Araujo in and out come pass di ball give Valverde wey try to place im shot. Ter Stegen save im shot go out for corner. Barca clear di ball afta. 10 mins - Aubameyang steal di ball from Nacho, im pass give Dembele wey try to dribble im way through Reak defence but Militao clear di ball. 12 mins - Double save! How Aubameyang no score dia? First Courtois deny di former Arsenal strike from five yards and den di Belgian also push clear Dembele curler. 14 mins - Di game don start so fast. Soon afta dat Barca chance, Vinicius test Ter Stegen wit low drive wey di goalkeeper catch. 17 mins - Ball Possession: Real Madrid 55% - 45% Barcelona. 18 mins - Ferran Torresss...wide! Di former Manchester City player try to bend im shot past Courtois but im bend am too much as di shot go off target. 22 mins - Yellow card for Toni Kroos wey foul Pedri. 24 mins - Pedri loop di ball over di Real defence to find Torres wey try to shoot but Militao recover quickly to block im shot. Di pass from Pedri na helele. 26 mins - Yellow card for Frenkie de Jong. Di Dutchman late tackle catch Kroos afta im don pass di ball. 29 mins - Goal for Barcelona! Pierre Emerick Aubameyang don head Barca into di lead from Dembele cross. Fantastic cross from Dembele. Dat na Aubameyang eight goal for im last eight games for Barcelona. 34 mins - Aubameyang almost extend Barca lead as im shoot from di left side but Courtois save am. Di Gabon forward dey worry Real Madrid. 36 mins - Real Madrid respond wit Vinicius clean through on goal, di forward trip imsef according to di ref wen im dey one on one wit Ter Stegen. Fans want Penalty but referee wave play on. 38 mins - Barcelona score again! Araujo jump high to head di Catalans 2-0 up for Bernabeau. 42 mins - Di match now na all Barca as Real Madrid no fit cope. Half time - Referee blow whistle for half time as Barca dey fully in control of dis match. Real Madrid 0-2 Barcelona Real Madrid starting XI: Courtois, Carvajal, Militao, Alaba, Nacho, Casemiro, Kroos, Modric, Valverde, Vinicius, Rodrygo. Barcelona starting XI (TBC): Ter Stegen, Araujo, Pique, Eric Garcia, Alba, Busquets, De Jong, Pedri, Traore, Ferran, Aubameyang. https://www.bbc.com/pidgin/sport-60804674 +sports Olympic Games Tokyo 2020: China Yang Qian win di first Gold Medal of 2020 Olympics China Yang Qian don win di first Gold Medal of Tokyo 2020 Olympics games. Qian of China take di gold for di women 10m air rifle final to collect di first gold medal of di 2020 Summer Games for di Asaka Shooting Range on Saturday. Na Anastasiia Galashina of Russia win silver, while Nina Christen of Switzerland win di bronze medal. Qian score of 251.8 set new Olympics record. Galashina score 251.1, while Christen record a 230.6 mark. Mary Carolynn Tucker score 166.0 and finish sixth, wey make her di highest-ranking American for di event. Di air rifle na one of three shooting events for di Olympics, along wit pistol and shotgun. Rifle and pistol go see competitors shoot at one stationary target, while shotgun requires dem to fire moving targets. Na two rifle distances: 10 meters and 50 meters, di 50m go require make shooters fire from three different positions: standing, kneeling and lying flat on di ground. For di 2016 Games for Rio de Janeiro, American Virginia Thrasher bin win gold, while Chinese competitors Du Li and Yi Siling take silver and bronze, respectively. Tori be say ten odas go contest for di first full day of action for different sports including fencing and weightlifting. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57952557 +sports Tokyo Olympics: Laurel Hubbard go be di first transgender athlete to compete for Olympics "New Zealand Laurel Hubbard don become di first ever transgender athlete dem pick to compete for Olympics, inside decision wey dey divided. Officials bin select her for di women weightlifting team for Tokyo 2020, afta dem recently adjust di qualifying requirements. She bin compete for men's events before she come out as transgender for 2013. Some pipo wey dey against di move say Hubbard get unfair advantage, but others don argue for more inclusion for di Games. ""I dey grateful and humbled by di kindness and support wey many New Zealanders don show me,"" Hubbard tok inside statement wey New Zealand Olympic Committee issue on Monday. She dey compete for di women's 87-kg weightlifting category. Di 43-year-old become eligible to compete for di Olympics wen di International Olympic Committee (IOC) for 2015 change di rules wey allow transgender athletes to compete as woman if their testosterone levels dey below ertain level. Testosterone na hormone wey dey increase muscle mass. Even as di athlete testosterone levels dey below that threshold, critics say her participation for di Olympics still dey unfair for female-born athletes. Dem point to di biological advantages of those wey don go through puberty as males, wey go don gada increased bone and muscle density. Last month, Belgian weightlifter Anna Vanbellinghen, wey dey compete for di same category, say if Hubbard compete for Tokyo, den e go dey unfair for women and ""like a bad joke"". She say even as she fully support di transgender community, di principle of inclusion no suppose be ""at di expense of others"". ""Anyone wey don train for weightlifting well-well reach high level know say dis dey true to dia bones: dis particular situation dey unfair to di sport and to di athletes,"" she tok for May. ""Life-changing opportunities dey missed for some athletes - medals and Olympic qualifications - and we dey powerless."" Save Women's Sport Australasia, one advocacy group argue against make transgender athletes compete for women's competitions, dem don also condemn Hubbard selection for di Tokyo Games. ""Di policy from di IOC dey faulty as e allow di selection of 43-year-old biological male wey identify as woman to compete for di female category,"" di group tok for inside statement before di Monday decision. But New Zealand goment and di kontri top sporting body don back her inclusion for di upcoming Olympics. ""Plus say she dey among di world best for her event, Laurel don meet di IWF eligibility criteria, plus dos wey dey based on IOC Consensus Statement guidelines for transgender athletes,"" New Zealand Olympic Committee chief executive Kereyn Smith tok. ""We accept say gender identity for sport na highly sensitive and complex issue wey require balance between human rights and fairness on top field of play,"" e add. ""As di New Zealand team, we get strong culture of 'manaaki' (respect) and inclusion and respect for all."" Di head of Olympic Weightlifting New Zealand, Richie Patterson, say Hubbard don show ""grit and perseverance"" to recover from one career-threatening injury wey happun for 2018. ""We dey look forward to support her for her final preparations towards Tokyo,"" e tok. Laurel Hubbard dey among di top ranked athletes for di world for her category. She get beta chance to win medal, as several others no go compete sake of rules by di International Weightlifting Federation (IWF) wey tok say na only one lifter go dey per category from each kontri. Hubbard participation for previous competitions don spark controversy in di past. For 2019 she win a gold medal for di Pacific Games for Samoa, she beat one athlete from di host nation, wey make pipo para. Samoa weightlifting oga bin tok say di New Zealander selection for Tokyo be like allowing athletes to ""dope"" and e fear say if e cost im kontri medal. For 2018, Australia weightlifting federation bin try to ban Hubbard from di 2018 Commonwealth Games for di Gold Coast. Organisers reject di move. But for di end Hubbard gatz withdraw from di competition sake of injury. Laurel Hubbard na weightlifter from New Zealand and dem born am for February 9, 1978. She dey selected to compete for di 2020 Olympics Games, she go be di first transgender athlete to compete for di Olympics afta she change her gender. Before e chage im gender, Hubbard bin set New Zealand junior records for 1998 for di newly established M105+ division wit snatch 135 kg, clean & jerk 170 kg, total 300 kg. For 2012, Hubbard change to female and she become Laurel Hubbard. For di 2017 Australian International & Australian Open for Melbourne, she compete for di heaviest 90 kg+ category, and e win di gold medal wit a 123 kg snatch and 145 kg clean & jerk, for a total of 268 kg at a bodyweight of 131.83 kg. Dis one make her become di first trans woman to win international weightlifting title for New Zealand." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57557628 +sports Champions League quarter-final draw: Chelsea vs Real Madrid, Man City vs Atletico Madrid, Benfica vs Liverpool, Villareal vs Bayern Munich make up quarter-final draw Di draws for di quarter-finals for di Champions League don take place on Friday, 18 March. Holders Chelsea go meet Real Madrid for di quarter finals of di Champions League. Man City go play Atletico Madrid, while Liverpool go meet Benfica and Bayern Munich go jam Villareal Di semi final pairing go see winner of Manchester City vs Atletico Madrid play winner of Chelsea vs Real Madrid. While winner of Benfica vs Liverpool go meet winner of Villareal vs Bayern Munich for di semi-final. Di first team drawn for each fixture go play their home match first, di first legs go hold on 5 and 6 April before di second legs on 12 and 13 April. Di first leg of di semi-finals go take place on 26 and 27 April and di second legs on 3 and 4 May. Stade de France for Paris go host di final on Saturday, 28 May after dem move am from St Petersburg after Russia invasion of Ukraine. Chelsea vs Real Madrid Manchester City vs Atletico Madrid Villareal vs Bayern Munich Benfica vs Liverpool Manchester City or Atletico Madrid v Chelsea or Real Madrid Benfica or Liverpool v Villarreal or Bayern Munich https://www.bbc.com/pidgin/tori-60775914 +sports Sack Ghana Coach CK Akonnor: Why Ghanaians dey call for sacking of Black Stars Coach "Ghanaians dey call for de sacking of national team coach, C.K Akonnor after de Black stars lose to South Africa. De Bafana Bafana of South Africa overpower de Black Stars with one goal to nil during de Qatar 2021 World Cup Qualifiers. Bongokuhle Hlongwane 82nd minute goal help Bafana Bafana secure all three points to top Group C with four points. Black Stars Coach, CK Akonnor after de game admit say de team no perform well, resulting in de loss. ""We no try in de second half...den we dey in control in de fest half... I no make happy,"" CK Akonnor talk media. Social media react over Ghana loss Most Ghanaians take to social media to register dema displeasure over de poor performance of de Black Stars. Some people however believe say he no be de problem, rather de football management body GFA for take de blame. Coach CK Akonnor performance C.K Akonnor take over as Black Stars coach in around January 2020 after Ghana Football Association (GFA) am. GFA appoint am to take over from former coach, Kwesi Appiah who at de time dey face challenges den issues of player indiscipline which people say affect de team. Since taking over de stars, he handle 10 games as Black Stars coach. Out of de 10 games, Blacks Stars win 4, lose 4 wey dem draw 2 under de leadership of CK Akonnor. After one year and nine months in charge of de national team, Black Stars statistics under CK Akonnor show say en win rate be 40%. According to football pundits, analysis of de performance of Black Stars dey show say de team dey struggle. Ghana Black Stars so far score 1 goal in last 4 matches, wey dem record only 5 shots on target in last 4 games. Ghana national team no win any major trophy in over four decades, de last time de country win be when Black Stars lift AFCON trophy in 1982." https://www.bbc.com/pidgin/media-58459845 +sports Villareal vs Liverpool highlight: Mane, Luis Diaz and Fabinho score for Liverpool afta Coquelin and Boulaye give Villareal hope for Champions League semi-final second-leg Liverpool book dia place for dis season final of di Uefa Champions League afta dem come from behind to beat Villareal wey finish di match wit ten-men. Di English side score all three of dia goals for second half to win 3-2 (5-2 on aggregate) afta Villareal race into two goal lead for first half. Fabinho, substitute Luis Diaz and Sadio Mane na dem score di goals for Liverpool afta Boulaye Dia and Francis Coquelin bin don open di scoring for Villareal. Jurgen Klopp and im boys bin no play like dem don do for much of dis season as Villareal bin ask dem so many questions for di first half. Afta only three minute, Dia tap Capoue cutback into di net before Coquelin increase dia lead just before half-time. Di Reds provide di answers for di second half as dem come alive afta Fabinho shoot shot through di legs of Villareal goalkeeper Geronimo Rulli wey no put in good performance on di tonight. Diaz wey come on for Jota for di second half den equalise five minutes later before Mane round off di 5-2 aggregate victory wit simple tap in into di net afta im don beat di onrushing Rulli. Villareal come go down to ten-men on 86 minutes, Capoue receive second yellow card for im late foul on Curtis Jones. Di man advantage no matter for Liverpool as dem bin don already do di damage to end Unai emery and Villareal giant-killing adventure for dis season Champions League. Liverpool wey fit win four trophies dis season now dey wait who between Real Madrid and Manchester City go face dem for di final wey go take place for Stade de France, Paris on Saturday, 25 May. No English side don ever win di Champions League, Premier League, FA Cup and League Cup all for di same season, Liverpool dey aim to create history. Liverpool go make change before di second half go start as Luis Diaz dey warm up. Im go replace Diogo Jota. 46 mins - Di home team don resume di second half. Big 45 minutes to decide who go qualify for di final. 48 mins - Keita run into Estupinan, referee don give Liverpool freekick for good position. Wetin go comot? Di cross from Alexander-Arnold hit Mane go out go out for goalkick. 52 mins - Luis Diaz introduction don give Villareal sometin to tink about as him and Foyth go put leg for one trouser for dat right hand side. 54 mins - Unlike di first half, Liverpool don dey come out to try press Villareal. Arnold send in cross wey Rulli catch well. 55 mins - Trent Alexander-Arnold long range shot take deflection from Coquelin come land on top di post. Liverpool come close! Soon aftawards Diaz shoot shot straight at Rulli. 60 mins - Liverpool don begin show di urgency dem need. Keita try to find Salah inside di box wit cross but Torres clear am. 61 mins - Liverpool pull one goal back! Fabinho drill hot shot through di legs of Geronimo Rulli. Villareal 2-1 Liverpool (2-3 on aggregate). 62 mins - If di tie end like dis Liverpool go qualify on aggregate. 63 mins - Yellow card for Capoue afta im foul goalscorer Fabinho. 67 mins - Diaz score Liverpool second. Di substitute rise high to head in lexander-Arnold cross. Villareal 2-2 Liverpool (2-4 on aggregate). 68 mins - Villareal make two substitutions. Chukwueze and Pedraza don come on for Coquelin and Moreno. 74 mins - Sadio Mane give Liverpool lead. Di Senegalese dribble past goalkeeper and defender as im slot di ball into empty net. Liverpool surely now don qualify for di final as e bel. Villareal 2-3 Liverpool (2-5 on aggregate). 77 mins - Yellow card for Liverpool right back Trent Alexander-Arnold. 79 mins Villareal make three substitutions. Alcacer, Trigueros and Aurier all come on for Boulaye Dia, Estupinan and Albiol. 80 mins - Liverpool respond wit dia own substitutions as Klopp don send on Henderson, Curtis Jonesm Tsimikas for Keita, Thiago and Robertson. Soon afta di away team almost increase dia lead but goalkeeper Rulli use im legs to deny Jones. 81 mins - Giovani Lo Celso receive yellow card for im foul on Fabinho. 84 mins - Milner don come on for Fabinho. 85 mins - Pau Torres don receive yellow card for im rash foul. 86 mins - Red card for Etienne Capoue. Di former Tottenham man take out Jones wit late tackle. 89 mins - Salah try to increase Liverpool lead but im scuffed shot go wide. 90 mins - We don enta two minutes of stoppage time. Full time - Villareal 2-3 Liverpool (Liverpool win 5-2 on aggregate). Liverpool don qualify for di 2021/22 Champions League final. 1 mins - Liverpool don start dis second-leg. 2 mins - Gerard Moreno handle di ball, referee blow for foul. 3 mins - Goal for Villareal Boulaye Dia don score im first goal for di Champions League. Di Senegal forward tap in Etienne Capou cutback to open di scoring. Villareal 1-0 Liverpool (1-2 on aggregate). 7 mins - Liverpool players look like say dem no expect dat early goal. Dem still dey lead but di game now don tie wrapper. 10 mins - Andy Robertson send in freekick into di box, di cross hit Jota leg go out for Villareal goalkick. 12 mins - Dani Parejo! Di Spanish side go close to scoring di scond goal but di midfielder shot just go wide. 14 mins - Thiago try im luck from just outside di penalty box, goalkeeper Geronimo Rulli just stand watch as di ball go over. 17 mins - Naby Keita try to draw di english side back into di game wit outside shot wey go out for goalkick. 22 mins - Moreno receive Capoue pass and try to break into attack but di flag don go up for offside wen im try to find Dia. 25 mins - Liverpool dey yet to get shot on target for dis second-leg as dem dey struggle to hold onto di ball. Ball Possession - Villareal 55%, Liverpool 45%. 30 mins - Van Dijk no dey happy afta referee blow im whistle say im foul Villareal player. Parejo send di freekick in, Alisson catch comfortably. 35 mins - Both teams dey find am difficult to create any meaningful chance as di game don go quiet for dat area. 38 mins - Villareal want penalty afta Lo Celso run into Alisson. Di Argentine dey down as im teammates ask di referee to check VAR. Di referee Danny Makkelie blow for corner instead. Di corner from Parejo no produce anytin. 40 mins Villareal score second goal Francis Coquelin don equalise di tie as im head di Spanish side level. 2-2 on aggregate. 42 mins - Liverpool forward Jota shoot towards goal but Albiol block im shot. 45 mins -Referee Makkelie don add two extra minutes before half time. Half-time Villareal 2-0 Liverpool (2-2 on aggregate). Villarreal XI: Rulli, Estupinan, Torres, Albiol, Foyth, Coquelin, Capoue, Parejo, Lo Celso, Moreno, Dia. Subs: Asenjo, Jorgensen, Gaspar, Mandi, Aurier, Iborra, Trigueros, Pedraza, Alcacer, Chukwueze, Pena, Gomez. Liverpool XI: Alisson, Robertson, Van Dijk, Konate, Alexander-Arnold, Thiago, Fabinho, Keita, Jota, Mane, Salah. Subs: Kelleher, Gomez, Matip, Tsimikas, Milner, Henderson, Oxlade-Chamberlain, Jones, Elliott, Minamino, Diaz, Origi. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61299999 +sports Ronaldo dey willing to join Chelsea, Eriksen don agree for Man Utd Chelsea dey consider move for Manchester United forward Cristiano Ronaldo, who don inform the Red Devils say e want leave this summer. (Athletic) Ronaldo, 37, dey willing to join Chelsea, but the Blues dey yet to decide whether to make formal offer for the Portugal international. (ESPN) Barcelona president Joan Laporta and agent Jorge Mendes dey discuss di possibility of former Real Madrid icon Ronaldo making a sensational return to La Liga. (AS - in Spanish) Tottenham don make enquiry for Barcelona'sNetherlands international forward Memphis Depay, 28, who fit leave the Nou Camp for £17m. (Sport - in Spanish) West Ham get dia £20m bid for Belgium international midfielder Amadou Onana, 20, rejected by Lille. (Athletic) Chelsea also dey in advanced talks with Manchester Cityfor England forward Raheem Sterling, 27, who dem value at around £50m by the Premier League champions. (Sky Sports) Italian champions AC Milan dey work on a deal to sign Chelsea's Moroccan winger Hakim Ziyech, 29, on loan. (Athletic) Christian Eriksen don agree in principle to join Manchester United on a free transfer. United go now finalise a three-year contract for the 30-year-old. (SKY) One player wey Arsenal dey reportedly target na Amadou Onana from Lille but e neva dey clear whether di Gunners go make formal offer for di player. (Sacha Tavolieri) Leeds United dey in talks to sign 23-year-old Colombian winger Luis Sinisterra, 23, from Feyenoord. (Express) https://www.bbc.com/pidgin/articles/cg6z0kz1np1o +sports Uefa Player of the Year 2021 nominees: Kanté De Bruyne, Jorginho make nominee list Uefa Player of the Year 2021 nominees shortlist for Men's award don come out. Manchester City midfielder Kevin De Bryune, Jorginho and N'Golo Kanté of Chelsea na di three nominees for di award. Dis na di first time in di 11-year history of di Uefa Player of the Year 2021 award wey all di nominees go be midfielders. Uefa go name di winner wit UEFA Women's Player of the Year during di 2021/22 UEFA Champions League draw ceremony. Di event go hold for Istanbul on Thursday 26 August. UEFA Champions League positional award winners go also hold then. Di award for di 2020/21 UEFA Europa League Player of di Season go happun di following day. Lionel Messi, Cristiano Ronaldo and Kylian Mbappe follow for di remaining 7 players wey make top ten list but not di final three. Di rest of di top ten Di shortlist of three players dey selected by one group wey get: Di members of di group go come chose dia top three players. Di first choice go get five points, di second go get three and di third go manage one point. And coaches no fit vote for players from dia own team. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58273213 +sports Joel Obi: Nigeria midfielder allegedly suffer racist abuse for Italy "Italian Serie B side Chievo don allege say Nigeria midfielder Joel Obi suffer racist abuse from e opponent during dia match against Pisa on Tuesday. Pisa and di player dem both don deny di accuse. Chievo tok for statement say Obi bin be di ""object of an infamous and disgraceful phrase wey no get anything to do with di most basic values of sport, ethics and respect."" Dem say Pisa player Michele Marconi used di phrase ""di slave revolt"" towards Obi for di first half of di 2-2 draw. ""Chievo... regret say disciplinary action no follow di phrase wey most pipo for pitch hear: neither by di referee, nor di assistant or fourth official, nor di federation delegate,"" dem add. Pisa say di club ""distance demself"" from Chievo statement, dem say match officials or di microphones around di pitch no detect di alleged insult. ""Moreover, our player confirm say im no address any insults to di opposing player, let alone to racially motivated ones,"" e add. Obi don spend most of e career for Italy, wia e don play for Inter Milan, Parma and Torino as well as di Nigeria national team." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55427880 +sports Champions League group stage scores & fixtures on Tuesday inside fotos Chelsea begin di 2022/23 Uefa Champions League group stage wit defeat on Tuesday. Thomas Tuchel team lose 1-0 for dia opening group match to Dinamo Zagreb. Tuesday fixtures see a total of 23 goals from di eight matches played. Manchester City and Shakhtar game produce di highest goals on Tuesday night four and five goals respectively. Di group stage start on September 6 and e go end for November 2. Na February 14 di knockout stages go begin and end wit di final for Istanbul on June 10, 2023. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2j40z30xj7o +sports Uefa apologise to Liverpool and Real Madrid fans "Uefa don apologise to Liverpool and Real Madrid fans wey di katata during di Champions League final affaect. Dem say e must not happun again. Liverpool fans describe di rough policing, poor planning and overcrowding during last Saturday showpiece game as sometin wey no make sense. Real Madrid don ask for answers on di ""series of unfortunate events"". ""No football fan suppose dey in dat situation, and it must not happen again,"" Uefa tok for statement. ""Uefa wish to sincerely apologise to all spectators wey experience or witness scary and distressing events for di build-up to di Uefa Champions League final for Stade de France on 28 May 2022 for Paris, on night wey suppose to be celebration of European club football."" European football governing body bin don announce independent review of wetin happun in di build-up to di final, and lessons to  learn, go dey led by Dr Tiago Brandao Rodrigues from Portugal. French authorities and Uefa bin blame late arrivals and fake tickets for di confusion outside di Stade de France, wey make dem delay di match for more dan 30 minutes. Police use tear gas and pepper spray on some fans. Dem also find out say some of di supporters become target of local gangs. France interior minister, Gerald Darmanin, say only English fans caused problem for di final. ""Di review na to establish full report and timeline of wetin happun during di day, both within di stadium and di surrounding areas, including investigating how fans take enta di stadium through different points,"" Uefa add for di statement." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cldv4405vy7o +sports Iheanacho goal carri Leicester enta FA Cup fifth round "Leicester manage to match brake for di ginger wey Brentford carri come for second half of dem two FA Cup fourth round match. Kelechi Iheanacho score di only goal of di game afta just four minutes when e tap in cross from full-back James Justin. Leicester na di better team for first half and Ayoze Perez suppose don score di second goal from Iheanacho pass but Brentford keeper Luke Daniels make ogbonge save. Afta di game Kelechi Iheanacho carrri di award for Man of the Match. E tell BBC MOTD: ""We dey happy for di win today and to go to di next round. Di oda team worry us well well. ""E dey very important as one team and as one group of players. We work really hard to di end and stand our ground. Fear catch me small because dem just dey come dey come. We defend well and in di end we win and we dey go through.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-51252242 +sports Nigeria vs Central African Republic: Super Eagles record shock defeat for Teslim Balogun stadium Central African Republic produce shock for Group C as dem beat Nigeria 1-0 for Teslim Balogun stadium for Lagos. Karl Namganda score di only goal of di game for injury time afa dem soak up lots of pressure from di Super Eagles. Di victory for Central African Republic end Nigeria unbeaten start to di qualification stage afta dem win dia first two group matches. Afta three matches, Nigeria still dey top of di group wit six points while Cape Verde dey second wit four points. Central African Republic get di same four points but dem don score fewer goals dan Cape Verde. Liberia na dem dey bottom of di group wit one point. Di two teams go meet again on Sunday for di second-leg. E go hold for Douala for Cameroon. Den dey play di match away from home because Confederation of African football rule say no football field for Central African Republic dey fit and proper for international matches. More dey come. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58835577 +sports Dominic Fobih: Meet di 10-year-old Ghanaian sport presenter Dominic Fobih, na 10 year old sports presenter from Ghana who wan become de next Jon Champion. He develop interest in football at age 6 wen he watch one UEFA Champions league final plus en brother. One big media house sign contract with him as sports presenter. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55529445 +sports Man United vs Copenhagen: Anthony Martial, Manchester United line up today, di big numbers dem get for Europa League ahead of FC Copehagen match "Manchester United go face FC Copenhagen for Cologne on Monday evening as di Europa League enter di 'final-eight' stage. Di Reds top group L with four points before dem see off Club Brugge and LASK, 6-1 and 7-1 on aggregate respectively, to qualify for di quarter-finals stage. Check out di team statistics for Europa dis season ahead of dia quarterfinal match by 8pm. Manchester United- 23 Basel - 20 Wolves- 19 Braga- 17 Sevilla-17 Man. United-154 LASK- 154 Sevilla-138 Frankfurt- 135 Wolfburg- 133 Manchester United manager Ole Gunnar Solskjaer say make pipo ""expect more "" from Anthony Martial afta di Frenchman best season so far for im career. Martial, wey be 24 years, score im 23rd goal of di season against LASK for Wednesday Europa League last-16 victory. Im neva score more than 17 goals for a single season before and im total for dis campaign don double in last two seasons combined. ""Physically, im dey di best level of im career,"" na wetin Solskjaer. Man. United- 55 Sevilla -55 Frankfurt- 50 Sporting CP-48 Basel-48 United dey unbeaten for 14 Europa League knock-out matches since dia 2-0 defeat to Liverpool for Anfield for di round of 16 for March 2016. Since then, dem don draw with di Merseysiders for Old Trafford and beat Saint Etienne, Rostov, Anderlecht, Celta Vigo, Club Brugge and LASK over two legs, plus Ajax for 2017 Stockholm final. In total dem get nine wins and five draws. 23 Benfica 21 Sevilla 20 Atlético Madrid 18 Valencia 17 Villarreal 13 Chelsea 12 Ajax 12 Liverpool 11 Arsenal 11 Manchester United 68 Benfica 64 Sevilla 64 Valencia 54 Atlético Madrid 50 Villarreal 41 Chelsea 39 Lyon 39 Manchester United 38 Athletic Club 37 Salzburg 37 Sporting CP 7-1 Lyon v AZ Alkmaar (23/02/17) 6-0 Valencia v Rapid Wien (18/02/16) 5-0 Man. United vs LASK (12/03/20) 5-0 United v Club Brugge (27/02/20) 5-0 Valencia v Basel (10/04/14)" https://www.bbc.com/pidgin/sport-53727222 +sports Fifa Best player 2020: Lewandowski beat Messi, Ronaldo to win men's player awards, see all winners "Na dat time of di year again when di best of world football go get recognition for di Best Fifa Football Awards wey, happen for di first time dis year, na virtual event. British sports journalist Reshmin Chowdhury and former ogbonge player Ruud Gullit of Netherlands go both host di virtual TV show. On di night Fifa president Gianni Infantino apologise say im no go fit attend di 2020 ceremony. Di awards begin with di Fifa Foundation Award wey Manchester United forward Marcus Rashford win, and e end wit Best Men's Player award. Dem praise Rashford for im ""inspirational work"" wia im help raise millions of pounds in donations and convince di UK goment to give free food to school students and families wey no too get money. Di awards also pay tribute to Diego Maradona. Last month, di football legend and one of di greatest players of all time, die at di age of 60." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55356919 +sports Karim Benzema don win im first Ballon d'Or award "French striker Karim Benzema don win di 2022 Ballon d’Or 2022 award for ceremony wey happun for Paris on Monday. Di Frenchman wey be 34 years bin score 44 goals in 46 appearances across all competitions last season. ""E make me very proud,"" na so Benzema tok. ""All di work wey I do, I neva give up. E be like childhood dream... Di Real Madrid striker follow say e get plenti pipo to tank, even thou na individual prize. Im goals help Carlo Ancelotti team to win di La Liga and Champions League. For Champions League im shine well-well for Real Madrid, sake of im hat-tricks for di last-16 second leg against Paris Saint-Germain and quarter-final first leg against Chelsea. Benzema no stop dia e still score again for dia second leg match against di Blues. E still score three more goals for dia semi-final first and second leg against Manchester City. Na so Karim Benzema tok as e collect di Ballon d'Or award from im old boss Zinedine Zidane for best player for 2022. E be di oldest Ballon d'Or winner since Stanley Matthews for 1956. Benzema, wey play ogbonge role for Real Madrid Champions League glory last season, na di first French player to win di trophy since Zidane for 1998. ""Pipo dey play until dia later years now and I still get dis burning desire. Na di drive wey keep me going and never allow me to let up. E keep dis dream alive and na di fire behind me. I just want to make di most of am."" E tok. Di Ballon d’Or award dey based on players performance for di previous season rather than di calendar year. For 2021/22 campaign, Benzema based bin dey very good form based on di goals and trophy wey im win. Na only four African players make dis list for dis award. Egypt and Liverpool striker Mohamed Salah, Ivory Coast and Borrusia Dortmund Sebastien Haller. Followed by Senegal and Bayern Munich Sadio Mane and Algeria and Manchester City Riyad Mahrez." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd1gk2y8kvqo +sports Nigeria vs Cape Verde live stream: Super Eagles World Cup qualifier preview, how to watch "Nigeria vs Cape Verde game kickoff by 5pm on Tuesday for Lagos. Nigeria gatz win or draw at home wen dem jam Cape Verde on 16 November, 2021 if dem go qualify for 2022 World Cup Qualifier playoffs in March. Di Super Eagles currently get 12 points at di top of Group C standings wit five matches played so far. While Cape Verde wey defeat Central African Republic 2 - 1 on Saturday dey at 10 points. So both di Tubarões Azuis [Blue Sharks] and di Super Eagles go dey aim for a win. As far as Group C dey concern, e dey right to say Nigeria vs Cape Verde qualifier match na winner takes it all. Nigeria lineup: 1. Okoye, 20. Awaziem, 5. Troost-Ekong, 6. Balogun, 3. Collins, 4. Ndidi, 10. Aribo, 15. Simon, 18. Iwobi, 9. Osimhen, 19. Ighalo. Cape Verde lineup: 1. Vozinha (G), 2. Stopira, 7. Andrade, 22. Fortes, 4. Fortes S, 3. Lopes, 20. Mendes (C), 10. Monteiro, 15. Moreira Fernandes, 18. Rocha Santo Venue: Teslim Balogun Stadium, Lagos Kick-Off time: 5.00pm Nigeria Football Federation dey expected to Live stream di match ontop dia web page between 5pm to 7pm on Tuesday as di Nigeria vs Cape Verde match dey happun. Click here to watch di Nigeria vs Cape Verde live stream. Also NFF say pipo fit watch dis match end to end via dia mobile app [TheNFF mobile app] on play store. Youth and Sports Development Minister Sunday Dare say; ""Winning away from home gatz boost Nigeria Super Eagles morale ahead of the all important clash against Cape Verde on Tuesday. ""Make we keep di focus. Make we finish di job in Lagos on Tuesday. We dey 100% behind una,"" Oga Dare charge Super Eagles. With 12 points, two clear of dia closest rivals, Cape Verde, di Super Eagles go need just a point at home on Tuesday to book a place inside di final round of 2022 World Cup African qualifiers." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59303962 +sports Gambia vs Cameroon: Karl Toko Ekambi shine as Indomitable Lions defeat prove Scorpions 2-0 for Afcon quarter final Two second half goals from Karl Toko Ekambi help send Cameroon into di semi finals as di Indomitable Lions defeat The Gambia 2-0. Cameroon dominate di match from start to finish as di debutants struggle to fashion out any chance but hold on until di second half wen dia defensive line crack. Toko Ekambi beat im marker to head home im fourth goal of di competition minutes just afta di game restart. Di Lyon forward soon double di Indomitable Lions lead as im fire in from close range afta Moumi Ngamaleu fine work from di touch line. Di goal see Ekambi move up to five goals for dis 2021 Africa Cup of Nations, just one short of im kontri man Vincent Aboubakar wey don score six. Cameroon go now wait to play di winner of di match between Morocco and Egypt while Gambia fairytale run for dia first Afcon appearance don end. 46mins: Di Scorpions don resume action as Musa Barrow take di first kick of di second half. 50mins: Goal for Cameroon - Karl Toko Ekambi don open di scoring wit header from Collins Fai cross. Gambia 0-1 Cameroon 53mins: Cameroon almost score second but Fai shot from tight angle go over. 54mins: Gambia make three substitutions. Modou Barrow replace Pa Modou. Mohamed Badamosi make way for Ebrima Colley while Ebrima Darboe come on for Saidy Sonko 57mins: Goal! Gambia 0-2 Cameroon. Toko Ekambi again. Martin Hongla lay square ball inside di box and Ekambi finish am off. 60mins: Those two goals from Cameroon don make dem look comfortable as dem dey threaten to score anoda. Di Indomitable Lions get 66% possession of di ball while Gambia get 34%. 73mins: Vincent Aboubakar shoot shot towards goal from di edge of di penalty box, but di shot fly just wide of di left post. 75mins: Moumi Ngamaleu dance im way into Gambia eighteen come shoot low shot wey Gaye catch. 77mins: Darboe and Ebrima Colley combine well, di former choose to shoot instead of pass but im no connect well wit di shot. 80mins: Cameroon make substitutions. Clinton Njie and Pierre Kunde come on for goalscorer, Ekambi and and Martin Hongla. Di referee use di opportunity of substitutions to signal for cooling break. 83mins: Gambia take off Marreh and Noah Sonko Soundberg, Assah Ceesay and Bubacarr Jobe don enter di match. Meanwhile Collins Fai no fit kontinu again as coach Conceicao don bring on Olivier Mbaizo. 85mins: Chance for Cameroon to score dia third! Njie fail to increase dia lead and Aboubakar balloon di rebound over. 87mins: Substitution for Cameroon, Christian Bassogog don come on for Moumi Ngamaleu. Zambo Anguissa come off for Yvann Neyou. 89mins: Foul on Bassogog. Di 2017 Afcon best player try to dribble im way into di Gambia eighteen but Touray foul am. 90mins: Referee Pacifique Ndabihawenimana don add three minutes extra time. Di Gambia clear di freekick from dat foul on Bassogog. 1min: Afta di teams observe minutes silence for fans wey die for di Olembe stadium, di match don start. 2mins: Di winner of dis game go play Egypt or Morocco for semi-final. 6mins: Cameroon defender Collins Fai fail to control crossfield pass wey for lead to attack as di ball go out for throw-in. 11mins: Cameroon hold possession of di ball and display neat passing from player to player. Dem dey wait for di right moment to open up di opposition defence. 15mins: First Chance! Aboubakar back hill attempt go over as im try to use style to convert cross. Di linesman flag say Aboubakar dey offside. Nothing resemble chance yet for either side. 21mins: Gambia defender Sonko don collect di first yellow card of di game. 23mins: Aboubakar go on solo run as di fans appreciate im effort, im pull back to Ekambi see di Lyon forward take shot but Colley block am. 26mins: Gouet run down di left come take shot but power no dey am as Gaye save am easily. 28mins: Oh so close! Moumi Ngameleu try im luck from distance, di shot hot di side netting. Many fans bin tink say e enter. 32mins: Anoda Yellow card for Gambia. Dis time na Modou receive am. 36mins: See save! Gaye stop Aboubakar from opening di scoring. Di goalkeeper use im body to stop di striker header from three yards. 40mins: Cameroon don dominate possession but di game still dey goalless as half time don dey reach. Baboucarr Gaye collect yellow for time wasting. 45mins: Referee add one minute before half time. The Gambia: Gaye, Sonko-Sundberg, Gomez, Colley, Jagne, Touray, Bobb, Marreh, Janko, Badamosi, Barrow. Cameroon: Onana, Castelletto, Ngadeu, Tolo, Fai, Hongla, Zambo Anguissa, Gouet, Ngamaleu, Toko Ekambi, Aboubakar. Make you dey refresh dis page as we go bring you live-text update of di match https://www.bbc.com/pidgin/sport-60180029 +sports Anthony Joshua vs Oleksandr Usyk 2 fight - Wetin you need know "Anthony Joshua and Oleksandr Usyk go face each oda again dis weekend. Di two boxers bin fight for September last year, Usyk beat di British-Nigerian boxer on points. Dat fight happun for London and di victory give di Ukraine boxer Joshua IBF, WBA, WBO, and IBO heavyweight titles Now Joshua dey challenge Usyk for di belts for Jeddah as im hope to bounce back from im second defeat for im professional career. If Joshua win e go become di heavyweight champion of di world again. Dis na all you need know about di ogbonge boxing fight. Joshua wey be 32 years no too ginger for di press conference, but im say im intend to ""get di job done"" dis time around. ""That's it, na must win. I like di pressure,"" Joshua add. ""I want to compete. I dey look forward to am. I no fit really tok too much. You gatz get competitive spirit. I dey look forward to am."" Usyk moral high well-well for di press conference, e wear traditional Ukraine cloth come. E say: ""We learn [about] each oda for di first fight. Him learn [about] me, I learn [about] him. ""... We get enough time to study each oda. Saturday night go be great, great fight."" Di defending champion sing one Ukrainian folk song, wey don dey popular now by those wey dey promote independence and peace for Ukraine since Russia invasion start. Di second fight between Anthony Joshua and Oleksandr Usyk go happun for August 20. E go begin from 6pm West African Time and di main event ring walk dey expected to start from 9pm. Di fight go happun for King Abdullah Sports City Arena in Jeddah, Saudi Arabia. Dis na Joshua second fight for Saudi Arabia and im go dey hope for di same result as last time. For December 2019, e beat Andy Ruiz for dia afta im surprise defeat to di Mexican earlier dat year. Meanwhile dis na di first time Usyk dey fight for Saudi and im go dey hope to keep im perfect professional record. For now no cable station dey carry di Joshua vs Usyk fight live for Nigeria. But e fit show abroad for Sky Sport and DAZN." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cj7e4exk90po +sports Jose Peseiro: Nigeria Football Federation executive committee approve new coach for Super Eagles "Nigeria Football Federation executive committee say dem don approve appointment of Jose Peseiro as new head coach of Super Eagles. Peseiro go replace German coach, Gernot Rohr wey di NFF announce im sack on 13 December, 2021. Di NFF tok dis one for one communiqué wey dem release on Wednesday. For inside di statement, dem say Austin Eguavoen wey dem bin name as interim head coach go lead di Super Eagles to Afcon 2021 for Cameroon. But oga Peseiro go ""only play role of Observer"" during di tournament while Eguavoen go return to im role as Technical Director wen di tournament end. Jose Vitor dos Santos Peseiro na Portuguese football manager and former player wey don coach Porto, Braga and Sporting Lisbon. During him playing days im be striker. Na April 4, 1960 dem born am for Coruche, Portugal. E cari Sporting CP reach di 2005 UEFA Cup final. For 2003 im work as assistant coach for Real Madrid. Between 2009 and 2011 Peseiro coach Al Hilal for Saudi Arabia before im comot go Braga for Portugal. Di 61-year old don also coach di Saudi Arabian national team. Jose Peseiro get experience for Africa too as im don coach African club, like side Al Ahly of Egypt. Im don also coach Venezuela national team before im take up dis new role wit Nigeria." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59821841 +sports Premier League, EFL games dey called off for Queen Elizabeth II death "Premier League and English Football League fixtures for dis weekend dey postponed as a mark of respect sake of di death of Queen Elizabeth II. Ten top-flight matches bin dey scheduled to hold across Saturday, Sunday and Monday. For di EFL, games suppose hold on Friday and Saturday. Di Premier League take di decision to honour di Queen's ""extraordinary life and contribution to di nation"" and say updates on future fixtures during di period of mourning ""go dey available in due course"". Di league chief executive Richard Masters say: ""We and our clubs go like to pay tribute to Her Majesty's long and unwavering service to our kontri. ""Dis na tremendous sad time for not just di nation but also for di millions of pipo around di world wey admire her, and we join togeda wit all dos wey dey mourn her passing."" Di goment national mourning guidance advise say cancelling fixtures no be by force, leaving di decision up to individual sports. Dem stop Horse racing on Thursday sake of di death of Her Majesty Queen Elizabeth II, while dem cancel di Test match on Friday between England and South Africa . All race meetings wey suppose hold on Friday too don dey cancelled for Britain, along wit di same day's Rachael Heyhoe Flint cricket fixtures. Di second day of di PGA Championship on Friday no go hold. Di English Football League don also postpone two games on Friday. ""A determination regarding di remainder of dis weekend's scheduled fixtures go dey known following a review of di official mourning guidance, in addition to further consultation wit DCMS and oda sports on Friday morning,"" EFL statement tok. Queen Elizabeth II, di UK's longest-serving monarch, died aged 96, afta reigning for 70 years. Following di announcement, dem stop di Southwell horse racing meeting afta di second race, and Chelmsford afta di fourth race. Di British Horseracing Authority dey likely to take a decision on wen horse racing go resume on Friday. Dem also abandon Play for di BMW PGA Championship at Wentworth. ""Out of respect for Her Majesty and di Royal Family, play don dey suspended for di BMW PGA Championship at Wentworth Club for di remainder of Thursday and flags at Wentworth Club go dey lowered to half-mast,"" European Tour Group tok for statement. ""Furthermore, no play go happun at di BMW PGA Championship on Friday and di golf course and practice facilities go dey closed"". Organisers say dem dey hopeful to restart di tournament at some stage ova di weekend but dem go ""review protocol guidance from Buckingham Palace in addition to aligning wit wetin oda major sporting events for di UK dey do"". In football, Manchester United say dia game against Real Sociedad for di Europa League go ahead ""following direction from di Football Association and Uefa"". Dem also play West Ham's game against FCSB for di Europa Conference League. Di Scottish Championship game on Friday between Cove Rangers and Dundee dey postponed. Cycling Tour of Britain don cancel dia final three stages in Gloucestershire, Dorset and di Isle of Wight, wit Spain's Gonzalo Serrano given race victorykeep im overall lead on Thursday's fifth stage. ""We dis decision in consultation wit stakeholders and partners in light of operational circumstances, including di understandable reassignment of police resource at dis time,"" a statement tok. ""Di Tour of Britain organisation, alongside di teams, riders and officials involved for di event, send dia deepest condolences to di Royal Family at dis sad time."" In rugby union, Northampton abandon dia Premiership Rugby Cup clash against Saracens on Thursday evening. Scotland women's Test international against Spain on Sunday too don dey called-off and Scottish Rugby also postponed all domestic competitive games dis weekend as a mark of respect. Friday's weigh-in for di women's world boxing title fight between Savannah Marshall and Claressa Shields go take place behind closed doors. Promoters Boxxer dey expected to issue a statement later on di status of di bout, wey dey scheduled to take place for di O2 in London on Saturday. Formula 1 dey plan one minute silence wit all teams before practice on Friday for di Italian Grand Prix, wit di race weekend to proceed as planned. For di US Open tennis for New York, organisers tok say ""to commemorate di passing of Queen Elizabeth II"" dem go do ""a moment of silence before di start of di first women's semi-final match between Ons Jabeur and Caroline Garcia""." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cxx9j5j3p2eo +sports Nigeria vs Cameroon friendly match: Time, how to watch, venue plus more Nigeria Super Eagles don land for Vienna, Austria to play friendly match. Nigerian senior national football team go take on di Indomitable Lions of Cameroon, on Friday. Di friendly game na to help Gernot Rohr men to stay in top shape ahead of September World Cup qualification games. Super Eagles go jam Liberia and Cape Verde for September World Cup qualifiers. With dis friendly match, Indomitable Lions and Super Eagles go meet for dia third international game inside 2021 Di last two matches na qualifiers for di Africa Cup of Nations. Toni Conceicao men no fit defeat Rohr team for dia last encounter during di 2019 Afcon Round of 16 encounter inside Alexandria. Di international friendly kick off time na 20:30 (West African TIme) on Friday, June 4 wey be 8:30pm inside Lagos, Nigeria. Cable channel Super sports go broadcast di match live for Channel 204 So you fit watch am dia. Dis match go shelle for Wiener Neustadt Stadium, Vienna https://www.bbc.com/pidgin/sport-57306288 +sports Morocco vs Ghana: 'Unlucky' Ghana ready to end Afcon yawa? Ghana no fit win de Afcon since 1982 na in captain Andre Ayew talk sey ino bi any problem wey dey worry de Black Stars but na luck wey dem no get. De Black Stars dey for Group C plus Morocco, Guinea den Comoros. Na de North Africa boys bi de ones wey Ghana go meet for Monday inside de Ahmadou Ahidjo Stadium for Yaounde. In go open door show sey the Black Stars go fit do well for inside Cameroon or luck go vanish for dema canp inside again. Ghana vs Morocco game for de 42,000 capacity stadium na im pipo dey talk say go be de proper big game opener for de tournament. Already Morocco go play di Afcon minus dema star player Hakim Ziyech as coach Vahid Halihordzic talk say de Chelsea player no dey show commitment for hin country side wey Covid don catch plenty of dema players. Ghana coach go thank God sey na hin do get that problem because after dem do covid test, Ghana go come out clean mean say covid no dey demma camp. Ghana don attend de Afcon 23 times wey claim de trophy four time inside 1963, 1965, 1978 and 1982 but Morocco attend 18 win only one for inside 1976. Morocco don win de Afcon once for 1976 and dem take part for de competition 17 times. Former captain Asamoah Gyan no go play this Afcon but Andre Ayew go lead new Black Stars players Kamaldeen Sulemana, Fatawu Issahaku, Joseph Paintsil, Mohammed Kudus who has remain for hin club talk say hin get injury. Ghana don include five players from de Ghana local league na de youngest player Fatawu Issahaku who win best player for de Africa U-20 Championship bi de player wey everybody for Ghana dey talk say e go blow for dis tournament. Morocco complain say covid dey worry demma players including Soufian Boufal who dem dey expect replace Hakijm Ziyech but still players like Paris Saint-Germain's Achraf Hakimi, Barcelona's Ez Abde and Wolve`s Roman Saiss, the captain who come talk say all Moroccans expect them to win something. Dis titanic Group C opener be de 12th time wey Ghana don meet Morocco for competitive game top. Ibi Morocco wey carry more wins for that inside as dem win five times wey Ghana win three. De first time wey de two teams meet na way back 1961 as dem play 0-0 draw for World Cup qualifiers. De big one wey Ghanaians never go forget be de match wey Morocco come play 2-2 plus Ghana in Kumasi wey commot de Black Stars from de 1998 World Cup qualifiers. Na for de Afcon group stage, dis be de fourth time de two sides dey meet as dem clash after meeting in de 1980, 2002 and 2008, de last one wey Ghana host den beat Morocco 2-0 for Accra come top the group. Ghana coach Milovan Rajevac don meet Morocco coach Vahid Halihordzic one time for Afcon inside in 2010 wehn Vahid dey coach Ivory Coast, im team den whip Ghana 3-1 carry victory in Angola. Former Ghana defender John Paintsil tell BBC Pidgin sey hin know de match go be tough but he dey see Ghana carry de day wit slim margin. He predict say Ghana go win 2-1 or 1-0. Morocco possible starting lineup: Bounou; Hakimi, Saiss, Aguerd, Tissoudali; Amrabat, Fajr, Barkok; Munir, Boufal, En-Nesyri Ghana possible starting lineup: Wollacot; Djiku, Armatey, Rahman, Mensah; Partey, Wakaso; Andre Ayew, Suleymana, Kudus; J Ayew https://www.bbc.com/pidgin/sport-59934932 +sports Football transfer rumours: Lewandowski, Osimhen, Mbappe, Dembele English club Chelsea fit join Barcelona to fight for signature of Polish striker Robert Lewandowski wey dey leave Bayern Munich (Guardian) Manchester United don join Arsenal to pursue Nigerian striker Victor Osimhen wey dey play for Napoli (Manchester Evening News) Newcastle United dey try tempt Roma manager Jose Mourinho to be dia next manager (Marca via Express) Incoming Manchester United boss Erik Ten Haag say e bin get oda choices but decide to pick di English giants as im next club (De Telegraaf) Manchester City midfielder Ilkay Gundogan fit leave di club at di end of di season (Mail) Barcelona dey try push to sign Leeds player Raphinha but West Ham also dey interested (90mins) Gareth Bale agent don confam say di Welsh player go leave Real Madrid at di end of dis season but neva confam wia e go play next (Mirror) Bayern Munich dey interested in signing Barcelona player Ousmane Dembele wey contract dey expire next month (Sky Sports) Arsenal don agree to sign Brazilian winger Marquinhos for a €3.5m deal wey go make am play till 2027 (Fabrizio Romano) Lyon say dem no go sign Tottenham midfielder Tanguy Ndombele permanently after im loan stint with dem (Football insider) https://www.bbc.com/pidgin/61476975 +sports Coronavirus: Cooking burns, dog bites - see di funny injuries Manchester United players don get during Covid-19 lockdown "Cooking burns, dog bites na some of di injury dem wey some Manchester United players don get during di coronavirus lockdown. Ole Gunnar Solskjaer team dey train for dia house as football dey suspended sake of coronavirus pandemic. United doctor Steve McNally say even though say di break don give di players time to recover, dem dey see increase for some kain funny-funny injuries. ""Fortunately, most of di boys dey well and we no get any real issues at all,"" na wetin di McNally tok for di club official app. ""Fortunately for us we no get injuries, although we get few unusual complains because dem dey try to cook, or tins like dia dog bite dem, dat kain thing. ""Di nutritionist put di boys for one Instagram page wia dem go take cooking lessons, so a lot of dem don start to dey develop new skill- and one or two of dem don get injury."" Even though dem dey away from dia training base for Carrington, Solskjaer's staff still dey monitor di players fitness, weight and nutrition" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52374642 +sports How Ghana beat Switzerland 2-0 for international friendly By Favour Nunoo and Fiona Equere Two goals from Mohammed Salisu den Antoine Semenyo give Ghana de victory against Switzerland. All de two goals for de Black Stars come in de second half of de game for de Ghanaian side. Afta Mohammed Salisu hit de back of de net in de 70th minute, Antoine Semenyo four minutes later in de 74th minute convert en strike into goal. De win against Switzerland dey put Ghana in beta position against Portugal who Switzerland during de qualifiers. Despite sitting out some of de key Ghana players like Thomas Partey and Mohammed Kudus, de Black starts dominate de second half of de game against dia opponents. Black Stars go face Portugal in de first game of de 2022 Fifa World Cup for Qatar on Thursday, November 24, 2022. FULL -TIME: Ghana 2-0 Switzerland 90 mins Second Half ends, Ghana 2, Switzerland 0. 89 mins-  Big chance for Ghana. Goalkeeper save Alidu Seidu right foot shot na Daniel-Kofi Kyereh give am di pass 87 mins- Ghana Alidu Seidu win free kick afta Renato Steffen foul am. 84 mins: Missed attempt for Switzerland. Haris Seferovic header from miss di target. 83 mins: Missed attempt missed by Ghana. Daniel-Kofi Kyereh right foot shot go wide. 80 mins: Substitution for Ghana. Alidu Seidu replace Tariq Lamptey. 77 mins: Substitution for Ghana. Joseph Aidoo replace Mohammed Salisu. 76 mins: Missed attempt. Switzerland Haris Seferovic left footed shot from the centre of the box miss di goal na Renato Steffen give di pass. 74 mins- Goal Ghana 2- 0 Switzerland Antoine Semenyo left foot shot from di centre of di box straight inside di net. 70 mins- Goal for Ghana, Muhammed Salisu score from corner kick. 69 mins- Ghana chance. Antoine Semenyo Ghana left foot shot from di left side of di box dey blocked. 67 mins- Kamaldeen Sulemana of Ghana don collect yellow card for bad foul. 66 mins- Eray Cömert for Switzerland win free kick for im team. 62 mins- Substitution for Ghana. Daniel-Kofi Kyereh replace Elisha Owusu. 60 mins: Offside for Ghana. Elisha Owusu play through ball, but Abdul Rahman Baba dey offside. 59 mins: Switzerland Silvan Widmer don collect yellow card for  bad foul. 57 mins: Switzerland Nico Elvedi win free kick for im team afta Ghana Jordan Ayew foul am. 55 mins: Offside for Ghana. Abdul Rahman Baba through pass to Daniel Afriyie but im dey offside. 49 mins: Granit Xhaka of Switzerland win free kick for im team na Daniel Afriyie of Ghana foul am. 48 mins: Missed chance for Noah Okafor of Switzerland im right foot shot miss di top right corner na Xherdan Shaqiri give am di pass. 46 Mins: Di score na 0-0 45 mins: Substitution for Switzerland. Nico Elvedi replace Manuel Akanji. SECOND - HALF Game don start Ghana 0-0 Switzerland FIRST - HALF 1 min: Game don start! Ghana 0-0 Switzerland 3 mins: Switzerland Denis Zakaria commit foul. 4 mins: Switzerland dey press Ghana Missed Attempt by Switzerland Rubén Vargas. Im left foot shot from di left side of di box miss di goal. 10 mins: Ghana first corner of di match 12 mins: Offside, Ghana. Abdul Rahman Baba through pass to  André Ayew but im dey offside. 13 mins: Switzerland get more of di possession pass Ghana so far for di game. 18 mins: Di score na 0-0 but di European team get upperhand 20 mins: Ghana Daniel Afriyie wins free kick for good area. 22 mins: Corner for Switzerland. 23 mins: Chance for Ghana but Jordan Ayew shot go straight to di goalkeeper 25 mins: Both team take water break. 27 mins: Referee restart di game afta dia water break to cool off for di heat. 30 mins: Switzerland Silvan Widmer win  free kick for di right wing afta foul by Ghana Jordan Ayew. 31 mins: Missed attempt by Ghana Iñaki Williams im header from very close range dey wide to the right na Jordan Ayew cross di ball. 35 mins: Anoda missed chance from Ghana dis time na Tariq Lamptey right foot shot from outside di box wey go wide. 36 mins: Chance for Switzerland. Remo Freuler right footed shot from di right side of di penalty box go wide, na Breel Embolo give di pass. 39 mins: Offside for Switzerland. Rubén Vargas pass ball to Xherdan Shaqiri but na offside. 42 mins: Referee blow whistle for Foul by Switzerland Breel Embolo. 43 mins: Missed chance for Ghana, Jordan Ayew find Mohammed Salisu but im blast di ball over di bar. 45 + 1 mins: Half-Time First Half don end, Ghana 0-0 Switzerland. 52 mins: Ghana Jordan Ayew win free kick afta Switzerland Noah Okafor foul am. Ghana XI 21 Abdul Samed, 17 Baba Rahman, 2 Lamptey, 4 Salisu, 13 Afriyie, 18 Amartey, 6 Owusu, 10 Ayew Andre (C), 9 Ayew Jordan, 19 Williams Inaki. Switzerland XI Sommer, 5 Akanji, 22 Schar, 3 Widmer, 18 Comert, 8 Freuler, 6 Zakaria, 10 Xhaka (C), 23 Shaqiri, 17 Vargas,  7 Embolo. Dis game be de final of three friendly matches de West African nation dey play as part of preparations for de de 2022 Fifa World Cup for Qatar. In de first game, Brazil beat Ghana 3 - 0, in dia second friendly Ghana manage beat Nicaragua 1 goal to nil. De final match against Switzerland go determine how ready de Black Stars dey for de tournament. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cnd513yy5g3o +sports Ronaldo say im deserve more Ballon d'Or pass Messi "Cristiano Ronaldo say im wan win more Ballon d'Or awards - di trophy for di world best player - pass im main rival Lionel Messi. Di Juventus striker Ronaldo, 34, don win di prize five times - di same number of time wey di 32-year-old Barcelona striker Messi don win am. ""Messi dey history of football - but I think I need to get six or seven or eight to dey above am,"" tok Ronaldo ontop one TV programme for UK - Cristiano Ronaldo Meets Piers Morgan. ""I go love am, I think I deserve am."" Ronaldo, wey don win 15 trophies in di nine years for Real Madrid, including four Champions League titles, dey hope say dem go remember am as one of di best players wey di game don ever see. ""I dey sure say I dey history of football for wetin I don do and wetin I still dey do, but one of di best players in history [na im I dey target],"" di Portugal captain tok join. ""For me, na number one for history, but for some fans, if dat number one belong to anoda pesin and I dey second, e no mata. ""I know say I dey history of football as one of di greatest ever,"" add Ronaldo." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49744141 +sports Wafcon quarter-final fixtures date, time and team update 2022 Women African Cup of Nations Quarter final line up don set afta di group matches end on Sunday. Defending Champions Nigeria, South Africa, Cameroon, Zambia, Senegal, Tunisia, Morocco and Botswana qualify for di Wafcon 22' knock out stage. Di quarter final round of matches for di women's tournament go begin on July 13-14. Winners of di quarter-final matches go qualify for di 2023 FIFA Women’s World Cup for Australia and New Zealand. While di two losers of di quarter-finals go get another chance to secure dia qualification through inter-continental playoffs. And na for Morocco, north Africa di competition dey take place. See di full quarter final fixtures here. Zambia and Senegal never pass di group stages for WAFCON before. But dis year edition dia hard work from many years of building and rebuilding don finally pay off. Captain Grace Chanda dey fine form, she don score twice so far for di tournament. But against Senegal, di Copper Queens go face one of di best defences for di tournament. Di Teranga Lionesses don only concede once so far – na penalty wey Morocco Ghizlane Chebbak score. Zambia too don let in just one goal and go hope to continue wit dia impressive defence wen dem face di West Africans. Di game go dey very open, as both teams dey like to counter attack and also fall back wen dem lose di ball. Di Wafcon quarter final match go happun on Wednesday July 13 for Stade Mohamed V  stadium for Casablanca. Di hosts dey unbeaten so far for di tournament, winning all dia Group A matches to collect nine points. Dem score five goals and concede just once, to top di table and book dia place for di quarterfinals. Captain Ghizlane Chebbak na di current leading goal scorer for di tournament with three goals Against Botswana, Chebbak and Morocco go dey up against one of di fastest teams for di tournament. Di game go shele on Wednesday July 13 for Moulay Abdellah Sports Complex for Rabat. Botswana, qualify for dis round through di two slots reserved for di two best third placed teams. Defending champions Nigeria go play dia arch-rivals Cameroon for Stade Mohamed V Stadium for Casablanca on Thursday July 14. Super Falcons finish second for Group C afta dia 4-0 win ova Burundi on Sunday. Cameroon beat Tunisia 2-0 for dia final group match to finish second for Group B. Dis match na repeat of di 2016 final for Yaounde, dis derby dey expected to produce fireworks. Super Falcons go dey without dia star player Asisat Oshoala wey dey out of di tournament sake of injury. 2018 finalists South Africa dey come into dis game as one of di two sides wey win all dia group stage games, and collect nine points. But dem go dey without dia star girl Thembi Kgatlana, wey dey out of di tournament sake of injury. Based on form and class Banyana Banyana get enough firepower to overcome Tunisia. Captain Refiloe Jane, Linda Motlhalo and Andile Dlamini na some of di standout players for Desiree Ellis side. However, di Carthage Eagles get dia own star too, Mariem Houji dey ready to give her all for dis game. Di game go happun on Thursday for di Stade Prince Moulay Al Hassan in Rabat. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cmle732e91eo +sports Casemiro say Man Utd move 'no be about money' "Casemiro say im  transfer move to Manchester United no be because of money. Na so di Brazilian tok as im say bye-bye to Real Madrid on Monday. Carlos Henrique Casimiro [Casemiro real name] say im dey join ""di biggest team for di world"". Di midfielder wey be 30 years spend nine-year spell with Real. United don agree to pay up to £70m to sign Casemiro on a four-year deal . Di contract go make am one of di top earners for di three-time European champions. ""If na about money I for don leave four or five years ago,"" e tok. ""Those pipo wey dey think dat way dey wrong, Dem no know me at all. ""Di club bin always treat me very well. Na my decision, my path."" Afta Casemiro join from Sao Paulo for 2013, e help Real win di Champions League five times, plus La Liga three times and di Cope del Rey once. Di footballer start last season Champions League final, as Real beat Liverpool to become European champions for di 14th time. And e don make 336 appearance for di Spanish giants. ""I bin speak to my agent afta di Champions League final as I bin get di feeling say I dey come to di end of my cycle hia,"" na so Casemiro tok. ""Na di hardest decision for my life but I' dey excited about di future. ""I want to face new challenges, know a different league, a different kontri and a different culture. ""I dey go di biggest team for di world, wey fit compete wit di greatness of Real Madrid, although not for now."" United don lose dia first two games of di new Premier League season and dem dey host Liverpool at Old Trafford on Monday. Cristiano Ronaldo bin win four Champions League titles alongside Casemiro for Real but di Portugal dey strongly linked wit a move away from Old Trafford dis summer. ""I neva speak to Cristiano, I hope say im go stay because im be one of di best players of all time,"" Casemiro add put. ""Evritin I do dia, I want to do hia too. I want to win di league hia. ""I dey go through one of di best moments of my career. I feel really fit, mentally I feel great, and I feel say na great time to take dis decision."" Real Madrid president Florentino Perez be also dey emotional during di ceremony wey happun for di Spanish champions' training complex." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn0yw3d85l8o +sports John Mikel Obi: Trabzonspor condemn racist abuse against former Super Eagles captain "Turkey club Trabzonspor don condemn racial abuse wey former Nigeria captain John Mikel Obi receive for dia win over Fenerbahce on Saturday. Fans target Mikel on social media afta 2-1 victory wey move Trabzonspor above dia opponents into third place. Di club say dem don file ""criminal complain"" against pipo wey dey responsible. ""Racism na shelter for di helpless and ignorant,"" na so Trabzonsport tok for statement for Twitter. Mikel wey also play for Chelsea tok say: ""We all be one and equal. At di end of di day, dis na just game e be.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-51374620 +sports Fifa World Cup 2022 Fixtures: Qatar World Cup Group stage standings, table and live results 32 teams, but only one fit win di trophy. Dat go be di hope of di 32 kontris wey go take part for di 2022 Fifa World Cup for Qatar. Na here you go find fixtures and results of all di matches from di group stage to di Final including di group table. https://www.bbc.com/pidgin/sport-63818464 +sports Frank Lampard: Chelsea sack manager afta 18 months in charge "Chelsea don sack dia manager Frank Lampard afta im spend 18 months in charge of di club. Di blues dey number nine position for Premier League table afta last week defeat to Leicester City, and dem don win once in their past five league matches. Im final game in charge of Chelsea na Sunday 3-1 FA Cup fourth round win against Championship side Luton. Lampard bin collect three years contract wen e replace Maurizio Sarri for Stamford Bridge for July 2019. Im guide dem to fourth place and play for di final of di FA Cup for im first season in charge, and wen dem win Leeds United 3-1 for December dem climb to top of di Premier League table. However, di Blues don suffer five defeats in dia past eight league games. For statement, Chelsea tok say: ""Dis na very difficult decision, and no be one wey di board and di owner take lightly. ""We dey grateful to Frank for wetin im don achieve for im time as head coach of di club. However, recent results and performances never mit wit di club expectations, as di club dey mid-table without any clear path to sustain improvement. ""Good time no ever dey to part ways with a club legend such as Frank, but after long tok-tok and consideration we decide change dey needed now to give di club time to improve performances and results dis season"". Owner Roman Abramovich say Lampard status as ""important icon"" of di club ""remain unchanged"" despite im sack. ""Dis na very difficult decision for di club, because I get excellent personal relationship with Frank Lampard and I get di utmost respect for him,"" na so Abramovich tok. ""Im be man of great integrity and get di highest work ethics. However, under current circumstances we believe na di best time to change manager.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-55798402 +sports Nigeria vs Guinea Bissau: Super Eagles clash with Wild Dogs for dia Afcon 2021 final group game - Wetin to know "Nigeria Super Eagles go face Wild Dogs of Guinea Bissau for Match Day three of di 2021 Africa Cup of Nations , (Afcon) for di Stade Roumdé Adjia in Garoua, Cameroon on Wednesday by 8pm. Di Eagles dey top of Group D afta dia 1-0 win over Egypt on Tuesday and 3-1 win over Sudan last Saturday. If dem win, dem go be di first team to gada nine points from di group stage of di 2021 Afcon tournament. Victory for di Wild Dogs go put dem in beta place to qualify for di next round of di Afcon for di first time in history. Dis go dey determined by di outcome of di second group D match between Egypt and Sudan. Guinea Bissau neva win any of dia matches for Afcon since dem begin come di tournament. Dem dey either loose or draw. Both teams neva meet before for international games, dis game go be dia first meeting. According to di latest ranking for December, Guinea-Bissau dey 106 for di world and dem dey 24th for di African continent. Nigeria dey rank 36th for di world and fifth for Africa. Di Wild Dogs neva score one goal for di 2021 Afcon even though dem get one point from di goalless draw dem play wit Sudan. Dis na dia third appearance for Afcon and dem neva pass group stage before for history. Di Super Eagles na three times Afcon champions and di 2021 edition na dia 19th outing for di tournament. Coach Austin Eguavoen say dem no expect di game to dey smooth for 90 minutes, but dia target na to convert dia chances to result and dem hope to see improvements for di match. ""Some kontris dey raise dia game anytime dem wan play Nigeria, we go dey ready on Wednesday"" na so di coach tok. E add say dem go respect dia opponents but dem 'no go comot foot off di pedal'. Baciro Cande wey be di Wild Dogs coach say dem don ready for di game. E say ""we go get plenti difficulties but we go play our game as usual like before and wit little lucky point to qualify"". ""Nigeria na traditionally a very strong team, we sabi dat. Dem show am for dia first two games, but we wan qualify for di next phase"" na so Cande tell tori pipo on Tuesday." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60040568 +sports Women's World Cup: Nigeria Super Falcons don crash comot against Germany Di waka of Nigeria Super Falcons don end for di Fifa Women's World Cup as dem lose 0-3 to Germany. Germany score dia first goal for 20 minutes wen Alexandra Popp head di ball inside net from corner. Den for 28 minutes, Sara Dabritz score penarity afta Nigeria defender Evelyn Nwabuoku foul German player for box. Di Super Falcons improve dia game for second half of di match, but no see road score. As e be so, na Cameroon be di only African kontri wey remain for di competition. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48732056 +sports US court convict Nigerian athletes afta FBI investigation "Nigeria athletics federation say di court sentence wey two of dia athletes chop for part wey dem play for one fraud scheme wey Federal Bureau of Investigation (FBI) uncover, dey ""sad and damaging"" for di kontri. On 10 November, Emmanuel Ineh and Toluwani Adebakin chop accuse for transferring tens of thousands of dollars to Nigeria as part of wetin di American justice department call ""complex fraud scheme"". Goment lawyers say di scheme bin involve athletes from multiple universities for USA, wit Africa Under-18 triple jump record holder Ineh, 23, and sprinter Adebakin, 25, operating part of di conspiracy wen dem bin be team-mates for William Carey University for Hattiesburg, Mississippi. ""E dey really sad and damaging, not just to di image of di sport or federation, but Nigeria as a kontri,"" Dare Esan, wey be board member of di Athletics Federation of Nigeria (AFN), tell BBC Sport Africa. ""Dis kain action fit affect oda young athletes wey dey find scholarships to American schools. E spoil di wonderful achievements wey oda honest athletes don create for world. ""But we know America na kontri  wit justice and fairness, so whoever dem find guilty go chop punishment and dem go make am pay di price for dia own actions."" Afta FBI investigation, di two plead guilty to violations of di United States code. Dis one na unto say dem put hand for unlawful activities and say dem send tens of thousands of illegal profit to fraudsters for Nigeria as part of bigger mail fraud, wire fraud, and money laundering conspiracy'. Both defendants go hear dia sentence on 15 February next year for Hattiesburg, and face maximum penalty of ten years for prison. ""Sadly, wire fraud and oda criminal activities no dey limited to athletics but don become national problem wey dem must to fix,"" Esan tok. ""Imagine someone like Ineh, wey win African [Youth] Games medal, dem catch am like dis? You allow dem to use you and your bank details to do fraud and decide to spoil your career - for what? ""E dey sad and disappointing to see young athletes wit great potential go dis way in life."" One federal district judge go determine any sentence for Ineh, wey finish for eitght position for di 2018 African Athletics Championships and Adebakin, wey im career no show dat kain promise, afta considering sentencing guidelines and oda statutory factors. Ineh na one of Nigeria fast-rising long jump and triple jump talents. Im move to University of Alabama earlier dis year. One African Youth Games silver medallist and continental age champion for di triple jump for 2018, im 8.16 metre long jump mark wey im set last year remain di National Association of Intercollegiate Athletics (NAIA) record. Adebakin graduate from University of South Florida for May wit dual degrees, one master degree for sports entertainment and anoda master for business administration (MBA). Im spent two years for William Carey University and win national championship for di 4x400m relay." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c806k6r82e8o +sports Raheem Sterling and oda footballers wey thief attack dia homes "England and Chelsea player Raheem Sterling leave Qatar wia im Three Lions’ team dey prepare to face France for Quarter Final for di ongoing FIFA World Cup after thieves enta im house. According to BBC Sport, im family including im three young daughters return to see jewellery and tins wey dem tiff. Dis na major cause of concern to di player wey make di English national team release am from duty to go see in family. Meanwhile, dis no be di first time wey footballers dey suffer dis kain wahala for dia homes, see oda times e don happun. Four months ago, armed robbers tiff tins from former Barcelona player Pierre-Emerick Aubameyang house . Im club at di time say na four armed men enta di Gabon striker house, and force am to open im safe. Di men take off wit im jewellery wey im keep inside di safe. Dis no be di first time armed robbers don break into footballers house for Spain. Na di second time dem dey break into Aubameyang house for Castelldefels. Di first time e happun, di player and im family no bin dey house for di first break-in, police tok. Most times, dis kain robberies dey happun wen di footballers no dey for house. For Barcelona, dem don break into Gerard Pique, Ansu Fati, Jordi Alba, Samuel Umtiti and Coutinho house and rob dem during games, according to police. Dis one happun to Bayern Munich and Senegal star Sadio Mane for 2019 wen e bin dey play for Liverpool. Co-incidentally, di incident happun while e dey field dey play against im present club Bayern Munich for Champions League. Di robbers break into im house wia dem steal watches, mobile phones and car keys according to police statement. Fortunately im family no dey inside di house at di time. For September dis year, dem attack di home of Liverpool footballer Alex Oxlade-Chamberlain and im musician wife. Di couple bin dey di property wen di break-in happun for Wilmslow, Cheshire for about 22:45 BST Cheshire Constabulary tok. Jewellery and handbags na im dem steal and officers bin appeal for anyone wit information, CCTV or dashcam footage to contact dem. Di couple just engage earlier dis year and get one-year-old son. Di family homes of Paris St-Germain players Angel di Maria and Marquinhos suffer burglary while French champions PSG dey play Nantes on 14th March 2021. Dis one happun as di two players bin dey in action for field of play. Dem substitute Argentina midfielder Di Maria for 62nd minute of di match afta dem tell am wetin don happun for im house. Im family only later know say dia home suffer burglary afta e happun. Same tin happun to Di Maria wen e dey play for Manchester United for 2015. Brazil defender Marquinhos at di time also yarn say im parents' home also suffer burglary but dat ""nobody dey hurt"". Dis one happun as Liverpool dey celebrate dia English Premier League title win for 2020. Dia midfielder Fabinho wey follow for di motorcade celebration no know say im house dey suffer burglary. Na later e discover say thieves break into im house and steal im car with jewellery. But police later find di car wey dem steal." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0370l05pv6o +sports Bundesliga table: Dis fotos from German league return go show you wetin football new reality look like Na 30 match balls, each of dem, ball boys go disinfect am and keep for special spots rather than handing am over to players. Dis na one of di many tins wey go change for football reality sake of Coronavirus. German Bundesliga action go continue on Sunday as league leaders Bayern Munich face Union Berlin later. But di first match go be Köln vs Mainz by 2:30pm Sunday. And like Saturday, clubs fit substitute pass 3 players up to 5 maximum - anoda changes to di round leather game. Substitutes all sidon for dia lane wit enof space from each oda and wear masks. Dis screen inside di stadium for RB Leipzig tell pipo to wash dia hands. Add to empty stadium, some goals na social-distancing alias dey your lane dem use celebrate. On Saturday, Borussia Dortmund players run to go celebrate in front of di empty South Bank RB Leipzig striker Yussuf Poulsen na from a safe distance fit stay interview am sake of corona. Police make sure say fans no gada outside. https://www.bbc.com/pidgin/sport-52698158 +sports Morocco beat Portugal to set new record for Africa and Arab for World Cup history Di Atlas Lions of Morocco don set new record for World Football as di first African kontri to qualify for di semi-final of di Fifa World Cup. Di North African kontri set di record afta dia hard earned victory over Portugal for di Qatar 2022 quarter final match. Di match hold for di Al Athumama stadium wia Morocco beat Portugal 1-0. Coach Fernando Santos bin bench captain Cristiano Ronaldo – e retain di same team and formation wey e use beat Switzerland 6-1 for di round of 16. But di Moroccans shock Portugal wit a 42 minutes gaol by Youssef En Nesyri. Dem later change dia formation to begin play defensive game to endure di pressure of attacks from Ronaldo and im men. Wit di win Morocco don become di third kontri to qualify for di semi-final of di 2022 Fifa World Cup joining Croatia and Argentina. Full-Time Morocco 1-0 Portugal EIGHT ADDED MINUTES 90mins RED CARD Morocco down to 10 men as Walid Cheddira two yellow cards within di space of 60 seconds. 89mins Chance for Cristiano Ronaldo but Bono keep im composure. Portugal dey running out of time. Morocco dey coast to victory 86mins Corner kick for Portugal but Morocco push am out. 81mins Santos no look too happy wia e dey siddon for di bench 80mins Morocco tanda gidigba and try to keep Portugal at bay. 79mins SUBSTITUTION Portugal carry another attacker enter- Ricardo Horta for José Diogo Dalot 74mins  After Silva no fit make sufficient contact forFernandes free-kick from di left touchline, Morocco temporarily get di ball away, but dat one sef no last as Portugal soon enough descend again; penning back di entire Moroccan XI inside dia defensive third. 70mins YELLOW CARD First yellow card of di match go to Achraf Dari for im tackle on Leao for di right flank 65mins SUBSTITUTION Morocco subtitutue dia goal scocer Youssef En-Nesyri wit Badr Benoun 60mins Fernandes shoot one free-kick from central position into di box, but one Morocco defenders head am away. Morocco dey 30 minutes from becoming di first African side to reach di semi-finals of di World Cup. Dem fit do am? 58mins CLOSE! Chance for Goncalo Ramos but di hat-trick hero against Switzerland plant im header wide. Dat na great opportunity to equalise but e no work! 57mins SUBSTITUTION Bad news for Morocco. Dia captain Romain Saiss no fit continue. Im replacement na Achraf Dari wey dey make im fifth senior appearance for im kontri. Im job na to stop Cristiano Ronaldo! 51mins SUBSTITUTION for Portugal Cristiano Ronaldo enta di pitch for im196th cap to replace Ruben Neves. Joao Cancelo for Raphael Guerreiro 46mins Portugal win first corner within di opening 90 seconds of di second half but e no gel 45mins KICK-OFF Half-Time Morocco 1-0 Portugal Di Atlas Lion dey 45 minute away from a place for di semi-final. 42mins Goal!!!!!!! Morocco 1-0 Portugal Youssef En-Nesyri give Morocco lead 31mins CLOSE! Joao Felix has look sharp going forward and e almost unlock di Moroccan defence with one first time shot wey deflect off Jawad El Yamiq and fly narrowly over di bar. Corner to Portugal. Meeting one dropping ball with a driven half-volley from the edge of the box, Joao Felix sees his goalbound effort blocked at close range by El Yamiq, who had previously failed to clear his lines. That was a rare opening in this first half for the Selecao! 23mins Bruno Fernadenz knock head wit Morocco keeper 21mins Morocco win second corner but no show at di end 20 mins No show, no goal from either sides so far 15mins Portugal so far for dis match don hold 79 per cent possession. 12mins Free-kick for Portugal. 9mins  Joao Felix almost escape for di left-hand side of di area, but e loose touch as e dey try to trap one sweeping crossfield ball wey allow Hakimi to intervene. 7mins Morocco respond sharparly with attack of dia own wey end with chance flying over di bar but na offside e be. 6mins Ogbonge chance for Portugal! One free-kick land for Morocco box and Joao Felix force Bono into flying save. 3mins  Whistles ring around di stadium as di Moroccan fans object to an early spell of Portuguese possession. Di Selecao dey carefully keep di ball inside dia own half. 1min KICK-OFF Morocco: Bono, Hakimi, El Yamiq, Saïss, Attiat-Allah, Ounahi, S Amrabat, Amallah, Ziyech, En-Nesyri, Boufal. Portugal: Diogo Costa, Dalot, Pepe, Rúben Dias, Guerreiro, Bernardo Silva, Neves, Otávio, Bruno Fernandes, Gonçalo Ramos, João Félix Walid Regragui fit miss di services of West Ham defender Nayef Aguerd afta di player suffer injury during di game against Spain. Romain Saiss and Sofyan Amrabat also remain doubtful to make di starting lineup due to injury concerns. Portugal all-time leading goal scorer and captain Cristiano Ronaldo dey bench once again. Dis na becos coach Fernando Santos fit wan stick to di same lineup wey e use beat Switzerland. Goncalo Ramos gp play di game wit Morocco wit plenty of confidence afta e score hat-trick for di big 6-1 win. Nuno Mendes and Danilo Pereira remain doubt to play a part in di game – as e be, Ruben Dias go continue to pair Pepe for back. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c25kww1jnj1o +sports Africa Cup of Nations: CAF require vaccination to attend Afcon 2022 for Cameroon "Afcon don set dia own Covid-19 rules ahead of di 2022 nations cup wey dey come up for Cameroon. Dis na as football clubs across di world dey take different measure to protect dia players so matches go fit continue. Afcon say fans must dey fully vaccinated and must present negative Covid-9 test dating back less dan 72 hours to get access to di stadiums during CAN 2022 for Cameroon. Dis na di main informate from di press conference wey shele for Yaoundé by di African Football Confederation, di Cameroonian Ministry of Health, and di Cameroonian Football Federation. CAF, di Cameroonian football federation and di Cameroonian Ministry of Public Health justify di decision say; ""Di concern na to avoid say Afcon fit cause additional wahala for di Cameroonian populations, participants and supporters from oda countries"" . Cameroonian Minister of Health, Dr Manaouda Malachie announce say vaccines and tests dey free. E further announce say dem go install vaccination units for all di sites to host di competition. Di health protocol wey CAF and di Cameroonian goment adopt dey cause gbege for Cameroon wia di vaccination rate against Covid-19 be 2% despite di campaigns wey goment start. Dis decision no go down well wit fans as some football fans dey point accuse finger for di Association of European Football Clubs wey dey threaten say dem no go release African players to participate for di next African Cup of Nations wey go shelle for Cameroon. Di association bin highlight Coronavirus pandemic and say dey no get enough device against covid-19 for Cameroon. Football fans dey doubt di government ability to deliver results to thousands of people within 72 hours. Odas don already dey reason to just settle for dia TV to experience di competition. Dr Manaouda Malachie assure say no Omicron variant for Cameroon and e claim say di Covid-19 curve don dey go down for di country. Di omicron variant of di coronavirus do spread to at least 11 kontris across Africa as at last week. Na so Africa Centers for Disease Control and Prevention (CDC) tok on Thursday. Africa CDC director John Nkengasong say: ""Seven more kontris - Uganda, Zambia, Senegal, Tunisia, Mozambique, Namibia, and Zimbabwe - don report di new variant over di past one week."" During di previous week Omicron bin only dey confirmed in South Africa, Botswana, Ghana, and Nigeria. According to Nkengasong, wey be a Cameroonian virologist, Africa don so far record eight point seven million COVID-19 cases and 24,000 deaths." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59688319 +sports Todd Boehly Chelsea new owner: Profile of Todd Boehly wey go buy Chelsea from Abramovich "Chelsea don agree terms to sell di football club for £4.25bn ($5.2bn) to a group of companies wey Todd Boehly lead. Todd Boehly be co-owner of di LA Dodgers baseball team and own stake for three sports teams for Los Angeles, America. Chelsea Football Club confam di sale on Saturday morning inside statement. Authorities put di club up for sale before dem sanction di former owner Roman Abramovich. Na for im alleged links to Russian president Vladimir Putin following di invasion of Ukraine, make UK punish Abramovich. Di Chelsea statement add say di new owners go pay £2.5bn for di club shares. Di money go dey transferred into a frozen bank account dem go donate to charity. Di consortium - led by Boehly as well as Clearlake Capital, Mark Walter and Swiss billionaire Hansjoerg Wyss - go also provide £1.75bn to invest in di Premier League club. Dis go include ""investments in Stamford Bridge, di academy, di women's team and Kingsmeadow and continued funding for di Chelsea Foundation"". For statement, Chelsea say di sale dey expected to complete in late May. Di takeover go require approval from di English football authorities and di UK goment. Chelsea dey operate under a special licence from di UK government wey go end on 31 May, but last month, Culture Secretary Nadine Dorries say di club dey on ""borrowed time"" to complete di sale. Any sale fit only get find approval of di bidder through di Premier League owners' and directors' test. So BBC Pidgin gada sharp profile of Todd Boehly wey Chelsea agree to be dia new owner. Todd Boehly na American investor and businessman, and get a reported net worth of $4.5bn (£3.6bn), according to Forbes. Boehly na part owner of di Dodgers - one US baseball franchise - and US women's basketball outfit di Los Angeles Sparks. E also get stake for di renowned LA Lakers NBA franchise. Im consortium also include American PR executive Barbara Charone, British businessman Jonathan Goldstein and British journalist Daniel Finkelstein. At di beginning na Swiss billionaire Hansjorg Wyss and Todd Boehly form part of one consortium to take over Chelsea. Oda consortiums wey bin get interest to buy Chelsea dey headed by Sir Martin Broughton and di co-owner of Boston Celtics, Stephen Pagliuca. Di mediators tell dem for late April say dia bids dey unsuccessful. British billionaire Sir Jim Ratcliffe - majority shareholder of chemical group Ineos - make late offer, but e enta on 29 April, several weeks beyond di initial deadline for bids of 18 March. Dem dismiss Ratcliffe bid but on 4 May e tok say im ""no go give up"". On Thursday, Abramovich say im no tok say make dem repay im £1.5bn loan to Chelsea wen dem sell di club. Abramovich toktok pesin say di Russian business man ""remain committed"" to making sure di money from di sale ""go to good causes"". Abramovich buy Chelsea for 2003 for £140m. But for im statement e announce im intention to sell im ownership ""no be about business or money, but about pure passion for di game and club"". Im values di club at £3bn and e don borrow di club £1.5bn. But say im no go ask make dem pay back any loan. Abramovich say im go donate di proceeds of di sale to war victims. Di funds from di sale go go one charitable organisation or into a frozen account. Football finance expert Kieran Maguire say di £3bn price tag ""no dey too much"" given di size of Stamford Bridge. ""Most commentators take di view di money no reach wetin pesin go want going forward,"" Maguire say. ""E no get capacity to increase Stamford Bridge sake of e location for London so to move else where for London go dey very expensive.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-61361260 +sports Chelsea vs Man City: Premier League predictions for dis weekend & match kick-off times "Chelsea against defending Premier League champions Manchester City for Stamford Bridge na one of di big games dis weekend. Di Blues dey unbeaten dis season afta five games and dey siddon ontop di league wit 13 points. While City don lose one match dis season and siddon for number five position. BBC football sabi pesin Mark Lawrenson don drop im predictions for dis weekend games wit im guest wey be legendary drum and bass DJ and producer Friction, Wey im new single I Need To Feel don come out. Friction na Arsenal season ticket holder wey bin fall in love wit di club wen im go Highbury at di age of 10, and enjoy to dey watch legends like Ian Wright, Dennis Bergkamp and Thierry Henry. E don dey follow di club for more dan three decades. ""I bin grow up to watch some amazing players and I bin enjoy some very special times, but for di last few years e dey very frustrating to be an Arsenal fan,"" e tell BBC Sport. Games go kick off by 3pm West African time except dem tok odawise. Di last time Manchester City bin go Stamford Bridge, na for January, dat game dem bin score Chelsea three goals inside 35 minutes, but dat na before Thomas Tuchel bin take ova and dis na very different Chelsea side now. Games between di big four - these two, plus Liverpool and Manchester United - go dey very important dis season. E dey obvious say dem go gap di rest, but in what order? These matches, and dia mini-league, go decide am. Chelsea dey hot form now and e show for di way dem finish Spurs for second half on Sunday but I tink say dis go be open game, because both managers no go wan lose. Lawro prediction: 1-1 Friction prediction: I go prefer City to win it, from di London point of view, but dis go be tough game. City dey capable of playing di most amazing football, but Chelsea just dey strong dey go. 1-1 Manchester United still dey try to find dia balance. Dem go win plenty games dis season, but sometimes e go choke dem. Di big question for me na if United fit win without playing well? I know say dem bin win for West Ham last week, but na narrow escape because of di penalty save for di end. Den dem change dia whole team and lose to di same opposition for di Carabao Cup in midweek, but na wetin di Hammers do too. Aston Villa bin beat Everton comfortably last time out and, before dat, dem bin play well against Chelsea and show say dem fit make life difficult for di top sides. United suppose win dis one, but e no go dey straightforward. Lawro prediction: 2-0 Friction prediction: Villa sign some good players during di summer but I feel say Bruno Fernandes go dey form for United, and Cristiano Ronaldo go enjoy imself too. 2-1 Everton bin fall yakata in di space of about 10 minutes for Aston Villa but dia problems no reach Norwich own. Di Canaries don lose all five of dia games so far and chop beating for dia house last weekend wen dem bin play Watford. Lawro prediction: 2-0 Friction prediction: Everton bin get bad week but dem go win dis one. 1-0. Leeds neva win game yet dis season, and dem look like a different team from wetin dem be last season. Dem don concede plenty of goals, though - 12 in five league games so far, and at least one in every match. Even wit dia poor form, I still tink say Marcelo Bielsa side go come good soon rather dan later. West Ham only league defeat bin come against Manchester United for strange circumstances, but I fancy Leeds to win dis one. Lawro prediction: 2-1 Friction prediction: Goals go dey dis game. 2-3 Leicester fit argue say dem no get luck for each of dia three league defeats so far, but dem gatz comot dat one for dia mind. Dis na tough game, even wit di slow start for Burnley. Di Foxes come from a goal down to beat dem in di Clarets past two visits to King Power Stadium, and dem go need to work hard to get dia season back on track. Lawro prediction: 2-1 Friction prediction: Leicester go win dis one. 2-0 Watford results dey up and down so far but dem get six points from dia first five games dem go dey satisfy wit am. Meanwhile Newcastle na one of five top-flight teams without a win and dia performances no dey too. I neva see anything wey go suggest say dem dey about to climb up di table. Lawro prediction: 1-1 Friction prediction: Dis game go dey tight. 1-1 Dis na Liverpool first visit to Brentford for di league since 1947 and di whole atmosphere don dey to welcome dem. Di Bees go dey lively for di pitch too - Ivan Toney dey do great job and di team sabi score, e go give dem a chance for di games - or most of di games anyway. I just feel say Liverpool go dey too strong for dem. Jurgen Klopp don begin rotate im team regularly but e no mean say e go affect di results - e dey generally get am right wen im drop pipo. Lawro prediction: 0-2 Friction prediction: Liverpool dey resemble dia old selves but I no tink say e go dey easy for dem. 0-1 I bin dey impressed by Southampton for dia draw for Manchester City last week. Dem neva win yet, but dem no be team wey look like dem dey any kind of trouble. Dat na why I dey support Saints to get dia first victory here. Wolves don lose four of dia first five league games and, although I no tink say dem go struggle for long, dem no dey strong as dem bin dey. Lawro prediction: 2-1 Friction prediction: I feel say dis game na di hardest out of di 10 to predict. I bin dey tempted to go for a 0-0 but Saints fit win am. Dem bin look good against Manchester City last week. 1-0 Tottenham bin win dia first three league games of di season, while Arsenal bin lose all dia games, but dia results don change in di past couple of weeks. I no fit say I dey surprised by dia inconsistency. I tok am from di start say I no fancy Tottenham defence, add to di fact say Harry Kane neva hit form yet for dem for di league. Arsenal don improve from di way dem bin start dis season but I no see dem dey go on a long unbeaten run now. Dem fit draw dis game. Dat na di result di two managers go wan settle for based on dia circumstances. Lawro prediction: 1-1 Friction prediction: Neither team dey great at di moment, but I feel say we dey a bit better dan dem. 1-0 Crystal Palace vS Brighton (8PM West African Time) Liverpool bin finish Crystal Palace last weekend, but odawise di Eagles dey OK so far under Patrick Vieira. Dis na Vieira first M23 derby as a player or a manager, and how im side go play go depend on Wilfried Zaha - di way im go play even if im no dey score goals imself. Wit four wins from five games, Graham Potter Brighton side dey OK. Lawro prediction: 1-1 Friction prediction: As far as dis game dey concern, e go hot. 1-1" https://www.bbc.com/pidgin/sport-58674414 +sports Arsenal vs Leicester City highlights: Gunners win 2-0 as Alexandre Lacazette and Thomas Partey score for Emirates "Arsenal return to occupying fourth position for di Premier League afta dem beat Leicester City for Emirates stadium. Dem beat di Foxes 2-0. Thomas Partey and Alexandre Lacazette score. Di Gunners bin dey fifth position, two points behind Manchester United wey defeat Tottenham 3-2 on Saturday. Cristiano Ronaldo score hat-trick to help di Red Devils overcome di determined Tottenham for Old Trafford. Arsenal bin dey hope to win and collect three points to be able to climb to di fourth position ahead of Manchester United and dem do am. As e be so, Arsenal don win nine of dia past 10 games for Premier League. Before di game start proper, both teams line up on di pitch behind banner wey dey in Ukraine flag colours with di message ""Football Stands Together"". Everyone for di stands dey on dia feet dey clap. KICK-OFF 1 min: Arsenal 0-0 Leicester We don start for Emirates. 3 mins: Alexandre Lacazette win di battle wit Daniel Amartey to get di ball inside Leicester area. Lacazette find Bukayo Saka but e no fit get di shot away. 5 mins: Five minutes in and no chance yet but Arsenal don dominate di possession so far. 8 mins: Gabriel Martinelli chase di ball down go di left and try to go past Ricardo Pereira inside di box. Martinelli go down as e challenge Pereira and some pipo dey shout penalty but e bin go down easily and di referee no dey interested. 10 mins: Kasper Schmeichel do well to keep out a point-blank shot from Gabriel Martinelli. Di flag go up for offside but regardless dat na fine block by di Leicester goalkeeper. 11 mins: GOAL! Arsenal don get di better of di opening exchanges. Dem don get 62% possession so far as dem score first corner of di game. Na Thomas Partey head am in from corner. 15 mins: Arsenal keep up di pressure as dem dey look to add a second goal. Dem win di ball high up but Granit Xhaka play one forward ball to nobody ane e go for goal kick. 17 mins: Notin much yet from Leicester in terms of attacks, not even one. Na defending levels dem dey for now. 19 mins: Arsenal go forward and play nicely to get into di box. Dem dey patient, dem dey try to find di right moment to shoot. Granit Xhaka shot dey blocked before Partey curl one ogbonge ball against di angle of di post and di bar. 21 mins: PENALTY APPEAL Bukayo Saka drive enta di box and go down with Leicester legs around am. Arsenal fans wan penalty, dem no give dem. 24 mins: Harvey Barnes dey picked out by one brilliant ball over di top by Kiernan Dewsbury-Hall. Di angle tight for Barnes and im shot dey deflected go corner, Aaron Ramsdale come punch am comot. 26 mins: Aaron Ramsdale push one low cross from di left into di middle of di box and James Maddison try to open up a bit of space for imself to shoot but Ben White challenge am well. 28 mins: Some nice passes from Kieran Tierney and Martin Odegaard as Arsenal bring di ball forward and work am give Bukayo Saka, wey go on to shoot but e dey blocked. 30 mins: Alexandre Lacazette get chance for Arsenal. E shot poweful shot but e go straight to Kasper Schmeichel. 32 mins: Gabriel dey down. Na afta e and Kelechi Iheanacho get small accident, Iheanacho put im hand for Gabriel face and e result to yellow card for am. 38 mins: Tins don change now. Arsenal now dey try to collect di ball from Leicester. 40 mins: Cedric no wan take any chance as e go behind James Maddison excellent ball inside di box. 43 mins: Alexandre Lacazette clip Marc Albrighton as di Leicester midfielder break forward. Leicester get a free kick midway inside di Arsenal half and James Maddison send am into di area for Caglar Soyuncum wey shin am over. 45 mins: HALF TIME! Referee don blow and na Arsenal dey lead, but Leicester finish first half strong. SECOND HALF KICK OFF 46 mins: No change for either side as second half resume. 51 mins: Gabriel Martinelli manage to keep di ball in play afta e skip Ricardo Pereira shot. E cut am back to Alexandre Lacazette, wey im shot deybblocked before Kasper Schmeichel punch away Bukayo Saka hooked effort. 54 mins: Gabriel Martinelli win foul afta e dey being pulled back wen e try to get through two Leicester players. Arsenal get free kick on di left. 56 mins: Somehow Leicester keep di ball out of dia net as Martin Odegaard free kick find di box and Kasper Schmeichel do well to keep out a shot from point blank range before Thomas Partey header dey cleared off di line. 57 mins: VAR dey check if Caglar Soyuncu use hand for di ball from Thomas Partey header and e be like say e do am. 58 mins: Anthony Taylor award penalty to Arsenal. Caglar Soyuncu collect booking afta di ball touch im fingers wen Thomas Partey try to head am in. 59 mins: GOAL! Alexandre Lacazette score di penalty. Arsenal players celebrate but Leicester players are fuming. 60 mins: Kasper Schmeichel dey question Anthony Taylor but di goal go stand. 62 mins: SUBSTITUTION Leicester boss Brendan Rodgers respond to dat goal by sending on James Justin and Wilfred Ndidi for Ricardo Pereira and Nampalys Mendy. 65 mins: Leicester break quickly as dem dey look to get a goal back and Marc Albrighton shoot from outside di box but e hit two Arsenal players to take di power comot am and Aaron Ramsdale stop am easily. 67 mins: Kieran Tierney hammer di ball away out of di goal way as Harvey Barnes bin wan hammer am in from close range. 70 mins: Twenty minutes to go and e be like say Arsenal dey cruise to a fifth consecutive win. 72 mins: Kelechi Iheanacho play one shot towards goal from just outside di box but Aaron Ramsdale catch am. 74 mins: Kelechi Iheanacho dey replaced by Patson Daka. 76 mins: Emile Smith Rowe dey on for Arsenal for di closing stages and dem clap for Gabriel Martinelli for an impressive performance as e go off. 78 mins: Granit Xhaka go through di middle. E get plenti support but im shot go over. 80 mins: Patson Daka bring down Bukayo Saka as di Arsenal forward drive towards di area. Di Leicester substitute collect cars and di Gunners get free kick 30 yards from goal. 81 mins: Cedric float di ball in, Leicester head away but Bukayo Saka pick up di loose ball before e shoot am but im effort dey blocked. 83 mins: Kasper Schmeichel block Emile Smith Rowe shot from a tight angle. 85 mins: SUBSTITUTION Bukayo Saka, dey limp small afta one heavy challenge, dem replace am wit Nicolas Pepe for di final few minutes. 87 mins: SUBSTITUTION Another change for Arsenal. Eddie Nketiah dey on for Alexandre Lacazette. 88 mins: Patson Daka try to turn wit di ball inside di area but too many Arsenal players dey around am. 90 mins: We just dey wait for di final whistle now. E no be like say anytin else go happun. FULL-TIME Arsenal 2-0 Leicester Arsenal don make dia fifth consecutive Premier League win." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60725613 +sports Anthony Joshua collect back all im heavyweight World titles Six months afta Anthony Joshua lose all im titles for di knockout wey shock di world, im don collect all im belts back for Saudi Arabia. Joshua jam Andy Ruiz again for di second time dis year for Dariya sport arena, to become two time world heavyweight champion. Im im win by decision wey all di judges gree to. Mexican boxer, Andy Ruiz Jr bin scata Joshua perfect record for boxing for June but now, Joshua don join di ogbonge group of boxers wey don fight collect dia titles back. Di group include, Muhammad Ali, Lennox Lewis, Evander Holyfield, Mike Tyson and Floyd Patterson. Meanwhile plenti pipo for inside social media follow to jollificate with Anthony Joshua afta im win. Some pipo even start dey learn moral lesson from di victory. https://www.bbc.com/pidgin/sport-50697617 +sports Why EPL stop 'take di knee' before evri football match "Premier League players go stop di pre-match anti-racism gesture of bending di knee before evri match. Instead dem fit take di gesture before certain rounds of games, including di Boxing Day fixtures and cup finals. Top-flight clubs begin take a knee to support di Black Lives Matter movement, and dis become popular afta di death of George Floyd for di United States for May 2020. Premier League captains say dem take di decision afta dem consult wit players. Players and staff go also fit take di knee before di first and last matches of di 2022-23 campaign. Dis go also happun for dedicated No Room for Racism match rounds for October and March. Di gesture bin happun before di Community Shield between Liverpool and Manchester City last Saturday. Captains and players say dem believe say 'less is more' – dey hope say wen dem take di knee e go get greater impact. ""We don decide to select significant moments to take di knee during di season to highlight our unity against all forms of racism... ""... and in so doing we continue to show solidarity for one common cause,"" dis na wetin one joint statement from di Premier League captains tok. ""We remain committed to comot racial prejudice, and to bring about inclusive society wit respect and equal opportunities for all."" However, Crystal Palace forward Wilfried Zaha wey stop for February 2021, tok dat time say ""at di moment e no mata whether we kneel or stand, some of us still continue to receive abuse"". Several Championship clubs, including Derby, Brentford, Bournemouth and Queens Park Rangers, also stop taking a knee around dat time. Swansea City and Bristol City recently announce dem go stop di action as well. ""We meet wit di captains last week, dem still dey totally committed to di issue,"" Premier League chief executive Richard Masters tell BBC Sport on Tuesday. ""For two years now taking di knee don become part of di pre-match ritual. “Di players fear say e dey lose power and momentum and we go see am take place in a different format”. Oga Richard tok. Na one NFL player Colin Kaepernick bin first inspire di gesture. Colin Kaepernick decide to go on silent protest against racial oppression wen e kneel during di US national anthem before one match for 2016. E tok say im no go fit stand to show pride for di flag of one kontri wey oppress black pipo. Di anti-racist statement don since become a prominent symbol for sport and during protests. E don also  become a feature of Black Lives Matter protests, including those wey follow di murder of George Floyd. Di practice of taking di knee enta football for 2020, sake of di murder of George Floyd for di US. A number of teams also take di knee during di Euro 2020 competition before some or all of dia matches, including Scotland, Wales, Belgium, Portugal and Switzerland. For 2021, England players take di knee during one of dia Nations League match wit Hungary to protest against racial prejudice." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz7prydy013o +sports Real Madrid vs Chelsea highlight: Benzema header put Real Madrid ahead 5-4 on aggregate afta Werner, Rudiger and Mason Mount bin give Chelsea hope Real Madrid book dia place for di semi-final of di Champions League afta dem fight back to win Chelsea 5-4 on aggregate despite say dem lose di match 3-2 afta extra-time. Di defeat on aggregate end Chelsea reign as European champions but dem go feel bad afta di effort wey dem put on di night. Di Blues bin race into three goal lead thanks to goals from Mason Mount, Antonio Rudiger and Timo Werner wey put dem in di driving seat. Dem even see VAR overturn goal from Marco Alonso before Real wake up from dia poor showing come score two. Substitute Rodrygo pull one back minutes afta im come on before Benzema wey score hat-trick for di first leg, score Real second for second half extra-time. Di Blues wey play well go look back on di first leg wia dem lose 3-1 as opportunity dem miss to put demsef in good position to qualify. 106 mins: Di second half of extra-time don start. 106 mins - Mateo Kovacic don go off, Jorginho don come on. 109 mins - Yellow card for kai Havertz. 114 mins - Yellow card for Cesar Azpilicueta wey sidon for bench. E be like im don tok sometin wey di ref no like. 115 mins - Change for Real Madrid. Daniel Ceballos in, Vinicius Junior out. 118 mins - Daniel Carvajal don receive Yellow card for foul. 120 mins - Three minutes added time. Full time afta exta time: Real Madrid don progress to di Semi-fina of di Champions League. 91 mins - Full time no separate dis two teams, na extra-time or penalties go settle am. 94 mins - Reece James try im luck from outside, di shot no get accuracy. 96 mins - Goal! Benzema gon give Real Madrid di lead on aggregate wit headed goal. 5-4 on aggregate in favour of Real Madrid. 100 mins - Kante OFF, Ziyech ON. 103 mins - Camavinga send left foot shot from outside di box over di Chelsea goalpost. 105 mins: Half time in extra-time. Real Madrid 2-3 Chelsea (5-4 on aggregate). 46 mins - Chelsea don restart di second half, dem dey lead on di night but need to score at least two goals to qualify. If e end like dis, na Real Madrid go progress. 49 mins - Reece James waya shot from outside di box but defenders block am. 51 mins - Goal! Chelsea don score dia second goal. Rudiger plant header beyond Courtois. Real madrid 0-2 Chelsea (3-3 on aggregate). 57 mins - Timo Werner dey flagged for offside by di linesman. 62 mins - Marcos Alonso score third goal for Chelsea. But Afta VAR review, di referee say no goal. Drama everywhere. 66 mins - Benzema! Di Real Madrid striker header come off di cross bar. 68 mins - Valverde collect Yellow card for im foul on Kovacic. 73 mins - Substitution for Real Madrid. Eduardo Camavinga come on for Toni Kroos. 75 mins - Goal! Timo Werner dribble past di last Real Madrid defender before im shoot di ball beyond Courtois. 78 mins - Real Madrid make two substitutions. Rodrygo and Marcelo replace Mendy and Casemiro. 80 mins - Rodrygo! Modric outside of di boot cross fall for di Brazilian feet to shoot first time. 4-4 on aggregate. 82 mins - Modric shoot from outside di box, im shot test Mendy wey catch am. 83 mins - Substitution for Chelsea. Christian Pulisic ON, Timo Werner OFF. 87 mins - Real Madrid make anoda substitution. Lucas Vazquez don replace Nacho Fernandez. 90 mins - Referee Szymon don add four extra minutes. 90+2 mins - Camavinga don receive yellow card. 90+4 mins - Chance for Pulisic to score anoda for Chelsea, o so close. Na extra-time go settle dis one. Full Time in normal time: Real Madrid 1-3 Chelsea (4-4 on aggregate). Extra-time go settle dis one 1 min - Di match don start. Na Real Madrid kick di game off. 4 mins - Chelsea don commit plenty men forward as sign of wetin dem need do if dem wan progress. Di Blues dey 3-1 down afta di first leg. 6 mins - Kai Havertz foul Toni Kroos. 10 mins - Yellow card for Reece James. Di Chelsea right back bring down Vinicius Junior. Benzema na im go take am. Di Frenchman shot go over di bar. 13 mins - Antonio Rudiger connect wit Alonso cross but im header go over di bar. 15 mins - Goal! Chelsea don take di lead through Mason Mount. Ruben Loftus-Cheek flick fall for di part of Werner wey curl di ball past Coutois to give di Blues di lead. Real Madrid 0-1 Chelsea (3-2 on aggregate). 25 mins - Casemiro commit foul wey see di ref talk to di midfielder. 28 mins - Matteo Kovacic smash one volley from long distance wey no trouble di goalkeeper. 32 mins - Benzema lay di ball off for Modric, but na Casemiro run onto di pass. Im baloon e shot. 36 mins - Real Madrid players never really create much for dis half as Chelsea na dem dey hold much of di ball. 37 mins - Yellow card for Karim Benzema. 41 mins - Ruben Loftus-Cheek don go down and need treatment. 43 mins - E look like say di Chelsea midfielder go continue di match. Di play don restart wit drop ball. 45 mins - Chelsea win freekick for good position. Kroos bring down Werner. Rudiger meet wit Recce James cross from di corner, im header no trouble Courtois as di ball go out for goalkick. Half Time - After one minute added time di Ref don blow for half time. Real Madrid 0-1 Chelsea (3-2 on aggregate). Real Madrid XI: Courtois, Carvajal, Nacho, Alaba, Mendy, Modric, Casemiro, Kroos, Valverde, Benzema, Vinicius Junior. Substitutes: Asensio, Marcelo, Lunin, Jovic, Lucas, Bale, Ceballos, Rodrygo, Mariano, Camavinga, Fuidias, Marin. Chelsea XI: Mendy, James, Silva, Rudiger, Alonso, Kovacic, Loftus-Cheek, Kante, Mount, Havertz, Werner. Substitutes: Arrizabalaga, Christensen, Jorginho, Pulisic, Bettinelli, Chalobah, Saul, Ziyech, Azpilicueta, Sarr, Vale. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61088367 +sports EPL fixtures, predictions and kick-off time Last week BBC football expert Chris Sutton bin predict right wen e say Liverpool go lose to Arsenal. But how im feel say di Reds go perform against Manchester City on Sunday. Sutton dey predict scores for evri game dis season wit different-different guest. For dis weekend fixtures, im dey up against one musician wey im name be Ian Broudie of di Lightning Seeds. Broudie na lifelong Liverpool fan, im prediction for Sunday game dey very different to Sutton. Before we reach Sunday fixtures make we start wit Friday & Saturday matches Afta dia good start to di season, Brentford form don drop badly. Last week Newcastle beat dem. E dey hard to know exactly wetin to expect from Brighton afta Roberto di Zerbi take charge, but dem bin dangerous team - and I feel say dem go win dis one. Sutton prediction: 1-2 Ian prediction: Di Zerbi don do well so far but I don see dis kain tin before where team form go just drop, e fit be say di players stop to do wetin di new manager wants them to do. For dat reason I dey go for Brentford. 2-1 Leicester last home game na against Nottingham Forest, dem play well for dat game, but dem come go backwards against Bournemouth last week. I know feel say tins don change - di Foxes defence still dey weak, Crystal Palace, and Wilfried Zaha, go capitalise on dat. Palace form too, bin get as e be until dem beat Leeds last time out. I feel say dem go cause Leicester problems, but di Foxes too fit hurt dem. Based on dat, I dey for a draw. Sutton prediction: 2-2 Ian prediction: Moral low well-well for dat Leicester team. 1-3 Fulham bin play well for di first half against West Ham but end up wit nothing to show for am. I always no dey send Bournemouth, and dem dey always prove me wrong. I know dia fans love am too... so you know wia I dey go wit dis. Di Cherries don do well unda Gary O'Neil, but I feel say Fulham go dey gingered for dis game, and dem go come wit point to prove. Sutton prediction: 2-1 Ian prediction: 1-1 Wolves still no get manager but dem get some good players, wey no dey play anywia near di levels we know dem fit. Dem dey di bottom three but I look dem as team wey no dey fulfil dia potential. Dats no really be di case wit Nottingham Forest, wey bin dey fortunate to get sometin out of dia game wit Aston Villa on Monday. Forest new signings neva click yet and dem be team wey e be like say dey don start to dey doubt diasef small small. Sutton prediction: 2-0 Ian prediction: Wolves no dey score plenti goals but I still tink dem go win. 1-0 Everton bin no really shine against Manchester United last weekend, even afta dem take early lead. Di Toffees defence don improve wella since di last time dem show for Spurs - dem lose 5-0 for March - but United show say you still fit get am. I feel say Everton boss Frank Lampard game plan go dey different, but to stop Spurs no go dey easy. Harry Kane dey form and Son Heung-min still dey my fantasy team and im go come good soon. So, Tottenham go find dia way. But how comfortable dis game go be for dem go depend on wen dem score dia first goal. Sutton prediction: 3-1 Ian prediction: Dis one go toff but I dey go wit Spurs. 3-1 Aston Villa fans no dey feel Steven Gerrard right now. Na sake of di way dem dey play and dia results. Meanwhile Pierre-Emerick Aubameyang dey score  goals and Graham Potter dey show say im dey adapt well. Villa go dey under pressure to win for home, and I feel say di pressure go affect di players. Sutton prediction: 0-2 Ian prediction: Stevie G need sometin, but e go hard. 0-1 As I bin tok earlier, Leeds bin play well for di first 45 minutes against Crystal Palace but dem bin no fit sustain am. Dis game fit follow di same pattern, as Leeds fit press early for di game, den fall apart later. Howeva e be, I dey expect Arsenal to win because dem dey hot at di moment. Sutton prediction: 1-3 Ian prediction: I dey see plenti goals for dis game. 3-4 I no think say Manchester United go win dis game. Di only question na, weda Newcastle go take three points home, or just one? No be say I no feel say Manchester United dey make progress under Erik ten Hag, bicos dem dey make progress. But I like as Newcastle dey bicos dem dey take di game to dia opposition, and di goals don start to dey flow – dem don score nine for dia past two matches. I no feel say Magpies boss Eddie Howe go change im team game for Old Trafford, because dat no be im style. Sutton prediction: 1-1 Ian prediction: 1-2 Dis na anoda another toff one. I feel like I go go for a draw for a lot of di games dis week - Liverpool versus City na one of di few wia I dey see a clear winner. Sutton prediction: 1-2 Ian prediction: 0-2 E dey hard to make case for Liverpool say dem still dey title race anyway, but if City go Anfield and win den na game ova for Jurgen Klopp's side; dem no get any chance to win di title. City know dis one, and dem know say dem fit finish dem dia. Dem rest Erling Haaland midweek so im go dey ready - and I feel say City dey dat good, dem go do di job dia. Liverpool fit still create opportunities, because of di way City dey set up, but wen you look both teams, City just too make brain. Sutton prediction: 1-4 Ian prediction: E go good if we fit get something but because of where we dey - I no feel say we dey challenge for di league. But If tins click, you no know o - Liverpool on dia day na wild card - but if dis na di final score den I am done finish for football! 9-0 https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjkxnlr6x78o +sports Cameroon vs Burkina Faso: Afcon opening match prediction and preview of Indomitable Lions against Stallions "Fifty years down since Cameroon host di Africa Cup of Nations di kontri de dream for change de bad memories for 1972 as Cameroon host finish for third place. For Group A, Burkina Faso na de first obstacle weh Cameroon get for komot for road as deh set for caress dia number six Silver Cup. Cameroon vs Burkina Faso curtain raiser for continental football bonanza go take place inside 60,000-seater Olembe stadium wit 89-year-old president Biya for front seat. Before now Cameroon na big powerhouse for football wit high level footballers like Roger Milla, Ndip Akem, Samuel Eto'o Fils, Patrick Mboma and odas. Cameroon don show 20 taims for dis continental competition, dem take de cup five taims for 1984, 1988, 2000, 2002, 2017. Even if taims don change de Indomitable Lions wit Portuguese Antonio Conceicoa Oliviera da Silva as coach get players weh Cameroon fit bank on. Cameroon na kontri for beta goalkeepers. Andre Onana weh e sign for Inter Milan dis week di give assurance for goal di follow foot-steps for Thomas Nkono, Joseph Bell Antoine and many odas. But Devis Epassy show e pawa when Andre Onana work suspension for doping after e consume bad substance. Midfield get heavy weight (Napoli) Zambo Anguissa weh di dictate tempo wit skill for snatch ball fast inside tight space. Cameroonians di count on Bayern Munich star Choupo Moting weh e shine for Germany dis pass season, and get potential for put smile for supporters dia faces. No bi Coach Conceicao yi only weapon as Karl Toko Ekambi for Olympic Lyonnais too di impress. Burkina Faso, di dream for lift dia first trophy wit players laik Bertrand Traore (Aston Villa), striker Abdoul Tapsoba (Standard Liege); kingpins weh deh helep de team to final for 2013. Coach Kamou Malo squad di look good wit young generation of players laik Herve Koffi, Edmond Tapsoba, Issa Kabore and Gustavo Sangare, ready for turn de tides. De Stallions get for improve two big tins if deh want progress for de tournament. Apart from quality, de team need strong mentality and de good news na say deh bring in psychologists for helep de team make e focus for achieve goals. Dia preparation get small hiccup as five of dia players; Abass Traore, Edmond Tapsoba, Soumaïla Ouattara, Saidou Simpore, Dango Aboubacar & coach Kamou Mal test positive for Covid-19 ahead of Sunday opener. Three other officials also test positive but di Burkinabe federation say dem go contest di positive test results as dem allege say mago-mago de inside. De team get 12 appearances for Afcon, eight less dan Cameroon. Cameroon and Burkina Faso don play five times against eachoda, de two teams win one match each and draw three. Burikina Faso 3-0 win over Gabon for friendly match weh deh play for Dubai na confidence booster before tough opener with Cameroon. De Stallions don keep clean sheet in dia last nine matches but de the Indomitable Lions wit no friendly match before Afcon no wan any disgrace in front of dia president. Cameroon coach, Antonio Conceicao for pre match pre-match presser say ""de team wan play beta football. We know weti Cameroonians want and de team get good form and ready"". Vincent Aboubakar, Lions captain declare, ""We know weti di happen outside de camp and we di train very hard for defend de Green, Red, Yellow national colors"". Kamou Malo Burkina Faso coach say ""de match no go easy but we go give Cameroon tough times"". ""Cameroon is and remain good football nation but we go do our best. We strength dey for we young team. First group match bi very important and we go work hard, do beta dan 2013"". Malo vex say medical team no respect Covid-19 protocol test dia players less dan 48 hour to de match. Former player, 1990 squad, Jules Denis Onana say Cameroon go win by 2-0 for seka say for more dan a decade, Lions nova lose any match for home turf. Fans are of the same opinion that the Lions cannot lose at home even if de score di change from one person to anoda. Fans di go forCovid-19 test di ready wit tickets for Cameroon- Burkina Faso game." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59922388 +sports PSG wan hijack Fofana from chelsea, Man utd turn attention to Sarr, Morata Manchester City dey in discussion with Barcelona over di sale of Portugal playmaker Bernardo Silva, 27, for a fee of between £42m and £46.5m. (Managing Barca) After ending dia interest in Bologna 33-year-old Austria striker Marko Arnautovic, Manchester United go now turn dia attention to Watford's Senegalese attacker Ismaila Sarr, 24. (Sun) United also get chance to sign Spain international and former Chelsea striker Alvaro Morata, 29, who get one year on im contract at Atletico Madrid. (ESPN) PSV Eindhoven the Netherlands forward Cody Gakpo, 23, na another forward wey dey interest Manchester United but dem go need part with around £35m for im signature. (Telegraph - subscription) Arsenal dey hold talks to sign AC Milanmidfielder Sandro Tonali, 22, but di Serie A giants want £46m for di Italy international. (Daily Mail) Mikel Arteta Arsenal also dey set to beat Liverpool to di £33m signing of Villarreal Spanish winger Yeremi Pino, 19.(Metro) Chelsea fit get dia record-breaking £85m transfer bid for Leicester City's French centre-back Wesley Fofana, 21, hijacked by Paris St-Germain. (talkSPORT) Thomas Tuchel's Chelsea dey also prepare another approach for Italian midfielder Cesare Casadei, 19, with Inter Milan now dey expected to accept fee of around £12m. (Evening Standard) Chelsea go also decide this week whether to pursue deal to bring Barcelona Gabon and former Arsenal striker Pierre-Emerick Aubameyang, 33, back to di Premier League. (FourFourTwo) Barcelona's Spanish winger Alex Collado, 23, na target for Scottish Premiership champions Celtic. (Daily Record) Leeds United get renewed hope say they fit seal di signing of Arnaud Kalimuendo, 20, with Paris St-Germain finally willing to put di French striker up for sale. (Yahoo Sports) Newcastle dey set to submit opening bid for Benfica £25m-rated Portuguese striker Goncalo Ramos, 21, who na also target for Paris St-Germain. (Daily Express) Barcelona dey offer Netherlands striker Memphis Depay, 28, to Serie A side Juventus as di Catalan club wan offload players to ease dia financial difficulties. (Goal) Aston Villa interest for £30m-rated striker Raul de Tomas, 27, don get boost after Espanyol'schairman admit say di Spaniard fit leave the club, although Everton, Newcastle and West Hamare also dey interested. (Birmingham Mail) https://www.bbc.com/pidgin/articles/crg82q23gd5o +sports 12 years after Luis Suarez handball, Ghana go face rivals Uruguay yet again Time dem say be healer but for most Ghanaians, de pain wey Luis Suarez cause after pushing de ball outside de pole in de 2010 World Cup quarter final match be unforgettable. De name Suarez dey evoke anger and bitterness in de minds of football loving Ghanaians, 12 years on de Black Stars dey face dia arch rival one more time on de global stage. ‘Back home, everybody who watch de game de dislike Suarez,’ Asamoah Gyan talk. ‘He be hero for Uruguay but people for Ghana dey see him as cheat. People do hate him’ he add. Asamoah Gyan dey receive both love and hate from Ghanaians since he miss de crucial spot kick wey for give Ghana ticket to de semi finals. To date, de player dey admit say de events of de game dey haunt am too date. What make de loss against Uruguay painful be say a win for Ghana in that game go be de first time African team enter semi-finals in de Fifa World Cup tournament. But on Friday, Ghana go lock horns with Uruguay inside winner take all match at de group stage of 2022 World Cup tournament. With three points secured, a win against Uruguay to qualify Ghana into de Round of 16, meanwhile a draw go fit still qualify de Black Stars unless South Korea beat Portugal with over two goals margin. But for de Luis Suarez and en Uruguay teammates, a win from de game be de only way to progress to de next stage. Although Ghanaians dey seek revenge, de Black Stars camp dey approach de game differently. De only player from de 2010 World Cup squad wey lose to Uruguay be Andre Dede Ayew. Dede Ayew be de current captain of de Ghanaian side who go face Uruguay. But for him, dis game no be about revenge, dia focus be to qualify for de Round of 16. “I be de only one who dey in de squad when dis happen, so de others no know how we feel but everyone feel bad.” “For me, I just want to get into de next stage so if e be revenge or not, we go go with de same determination and desire to win sake of we want go de next stage” he talk. According to de Black Stars captain, de game with Uruguay no be about revenge, de Black Stars coach Otto Addo dey share in dis view too. Otto Addo believe say no need to go into de game with revenge mindset. “De incident happen long time ago wey I be strong believer that if you no seek too much revenge on dis kind of thing sometimes you get de blessings” he talk de press. De 2010 clash end in tear for Ghana after dem lose on penalty shootout to Uruguay. But de events wey happen before de end of de game dey remain one of de most dramatic moments in de Fifa World Cup tournament. Ghana almost net de ball to give dem 2 - 1 lead over Uruguay, but at de time 23 year old Suarez who dey inside de pole use en hands clear de ball from de pole. De referee show am red card wey he award penalty, but Asamoah Gyan painful hit de bar from de penalty spot. Suarez who dey head to de dressing room start dey jubilate as Ghana Miss de penalty shoot. De game remain 1 - 1 draw until dem go penalty shootout where Uruguay beat Ghana 4 - 2. Since then, Ghanaians declare Luis Suarez nation number one public enemy. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cnlgxjzere8o +sports Ghana Black Stars: GFA list AFCON 2023 qualifiers squad "Black Stars head coach, Otto Addo today name en squad for de upcoming 2023 Africa Cup of Nations qualifiers, den de four-nation tournament which go happen for Japan. Otto Addo release de 33-man list on Thursday ahead of de game against Madagascar den Central African Republic. In November 2022, Ghana go be one of de 32 countries who go participate in de Fifa World Cup tournament for Qatar. Ghana despite crushing out of de Afcon 2021 tournament during de group stages, beat rivals Nigeria in de Third-leg of de World Cup Qualifiers to book dia place. Dis go be de fourth appearance of Ghana for de World Cup competition after de Black Stars feature in 2006, 2010 den 2014. New technical team led by Coach Otto Addo den Chris Hughton manage book de Black Stars a spot in de World Cup against all de odds, de Ghana Football Association now dey scout around for players who go fit help beef up de Black Stars squad. Sake of dis, some Ghanaian footballers who dey play for foreign countries sake of dem born dem outside dey on de GFA list for possible call ups. Dis be some of de players wey GFA give indications say dem dey go after ahead of de tournament. One of de key players wey dey on GFA radar for de Black Stars be Brighton, Holve and Alvion right-back, Tariq Lamptey. Recent reports dis week from BBC Sport be say England Under-21 head coach, Lee Carsley say de 21-year-old defender request say make dem leave am out of de Under 21 squad. ""He request say make we leave am out of de squad small make he think"" Lee Carsley talk. Lee Carsley explain say Ghana approach Tariq Lamptey, wey be like he dey ""consider"" de offer. Ghana Football Association start dey pursue de London-born defender since around 2020, but football pundits say de World Cup be major encouragement for de lad to join de Black Stars. Lamptey, get two Under-21 caps dey qualify for Ghana through en parents. Another player wey dey top on de list for Ghana be Chelsea and England winger, Callum Hudson-Odoi. Ghana President, Nana Akufo-Addo make personal call on de player to switch nationality den join de Black Stars. Inside twitter post last year, Prez Akufo-Addo write say ""Ghanaian-born Chelsea footballer, Callum Hudson-Odoi, pay courtesy call on me for Jubilee House, de seat of wana presidency."" ""Amongst others, I advise de Minister for Youth and Sports say make he explore de possibility of having Callum switch nationality, den play for de Black Stars. Odoi en switch to Ghana be possible sake of en parents be Ghanaian, dem born am for Ghana until he later later acquire British citizenship. He make three appearances for de Three Lions and several others in the England U21. According to Hudson-Odoi, ""the thing obviously say I go choose Ghana or England, at de end of de day I said I always have de right people around me who always advise me - what be right, what be wrong."" ""England come wey I say yeah, let me go and play for my country. But I talk say Ghana be my home as well, so we go see, we go see. You never know..."" he talk on Accra-based Joy FM. Despite say he play three times for de Three Lions of England, as per Fifa rules, he go fit switch nationality to Ghana so far as he no play more than three senior matches for England. Also, one go fit switch to different nationality three years after de last international appearance. Dis mean say Hudson-Odoi go fit make dat switch next year November, before 2022 World Cup go start. Eddie Nketiah be London born footballer who dey play forward for Arsenal, but de young lad be eligible to play for both England and Ghana. Dis be sake of en parents be Ghanaians but dem born am in England so he get British citizenship. In 2017, Nketiah get en first international call to play for England Under 18 level, wey he later play for Under 19. In October 2020, Nketiah become England U21's all-time leading goalscorer aftern he broke Alan Shearer record. De Ghana Football Association (GFA) make efforts over de past few years so say Nketiah go switch to Ghana but so far e no clear yet what en decidion go be. Recently, uncomfirmed reports start dey circulate say de player secure Ghanaian passport, although he no personally confirm or deny de claims, he mention say he go like focus on de future of en club football first before national football. Per Fifa rules on switch of nationality, players according to Article 8 who wan change national teams for formally request a change from Fifa. Fifa then go review dia case on de Players Status Committee. But sake of Eddie Nketiah no play for England yet at for de senior level, de process go be more straightforward for de 22-year-old. Apart from dis players, other players who dey excel for club football like Inaki Williams brothers who dey play for Atletico Bilbao, Mohammed Salisu who dey play defence for Southampton. Also, Bristol City striker, Antoine Semenyo dey on de watchlist as one of de players who go fit make de Black Stars list as he show readiness to play for de national team." https://www.bbc.com/pidgin/sport-61596213 +sports La Liga standings: Lionel Messi equal Pele record but Barca drop league points Lionel Messi equal Brazil legend Pele record of 643 goals for one single club after e score for Barcelona 2-2 draw against Valencia on Saturday for La Liga. Di Argentine, 33, achieve di feat wit diving header just before half-time, immediately after Valencia goalkeeper save e penalty. Messi score e first goal for Barca for 2005 against Albacete. Pele score 643 goals for 19 seasons for Brazilian side Santos between 1956 and 1974. But even though Messi equal anoda record, Barcelona fail to close di gap on first place Atletico Madrid wey also win 3-1 against Elche. Di result see Barcelona remain fifth for table, eight points behind Atletico Madrid. Two goals from Luis Suarez help Atleti move clear for di top of LaLiga table, dem still get three outstanding matches. Even though di league don enter matchday 15, some teams never play reach 15 matches Atletico Madrid dey top wit 29 points while Real Sociedad dey second on 26 points. Real Madrid wey go play Eibar later on Sunday dey third wit 26 points while Villareal complete di Top-four position wit 25 points. https://www.bbc.com/pidgin/sport-55384489 +sports Chelsea dey prepare new bid for Fofana, Mourinho eye Arsenal Lokonga West Ham don make fresh bid for 24-year-old Brazil midfielder Lucas Paqueta after dia opening offer of 50m euro (£42.2million) dey rejected by Lyon. (Telegraph - subscription required) Manchester City don reject 70m euro (£59m) bid from Paris St-Germain for Portugal midfielder Bernardo Silva, 28. (Times - subscription required) Chelsea dey prepare new bid of around £75m for Leicester defender Wesley Fofana, 21. (Fabrizio Romano) Club Bruges don also turn down di Hammers £10m bid for Belgium midfielder Hans Vanaken, 30. (Evening Standard) Ajax head coach Alfred Schreuder say e dey confident say winger Antony, 22, no go go to Manchester United despite latest £76m bid. (Metro) Manchester United get offer chance to sign Real Madrid and Spain winger Marco Asensio, 26, for 30m euros (£25.3m). (Telegraph - subscription required) United dey set to submit £25m offer for PSV Eindhoven and Netherlands winger Cody Gakpo, 23. (Football Insider) Di Old-Trafford club don make fail bid for Bayern Munich right-back Benjamin Pavard, 26. (L'Equipe - in French) Eintracht Frankfurt and Germany goalkeeper Kevin Trapp, 32, don reject offer from Manchester United. (Guardian) Liverpool pursue of 19-year-old England midfielder Jude Bellingham fit get help by Borussia Dortmund interest in Guinea midfielder Naby Keita, 27, who join di Reds in 2018. (Express) Arsenal midfielder Albert Sambi Lokonga, 22, dey on Jose Mourinho midfield shortlist for AS Roma as e dey look to replace injured Gini Wijnaldum. (AS Roma Live, via Express) Wolves don enquire about Galatasaray and Denmark centre-back Victor Nelsson, 23. (Mail) Bordeaux dey interested in signing Fulham's out-of-favour French winger Anthony Knockaert, 30. (Football Insider) Southampton manager Ralph Hasenhuttl say forward Che Adams, 26, no be for sale dis summer. (Southern Daily Echo) Manchester City and England Under-21 midfielder Cole Palmer, 20, dey wanted on season-long loan by Borussia Dortmund. (Sun) https://www.bbc.com/pidgin/articles/cpdx9jye12jo +sports La Liga fit resume behind closed doors from 8 June La Liga go fit resume behind closed doors from 8 June according to Spain Prime Minister Pedro Sanchez. Di League president Javier Tebas say im dey hope make Spain top flight fit start for 12 June as La Liga neva confam di date wey dem go restart. La Liga players don begin train dis week and dem no pass more dan 10 for inside one group. According to di Presido, Spain don do wetin im suppose do and time don reach to bring back di day to day activities. He say from June 8 La Liga go return and Spanish football get plenty followers and no be di only sport wey go return be dat. Di Spanish second division don already set to resume as report dey suggest say derby between Sevilla and Real Betis go be di first La Liga game wey go happun. Oga Tebas say dem happy wit di decision and dem go follow all di health rules to make sure say di pandemic no come back. Dem suspend football for Spain for 12 March sake of coronavirus pandemic. Five players bin test positive for coronavirus among Spain top players and dem don go isolation before dem allow di first phase of traiing wey start for 18 May. La Liga teams get 11 games to play dis season, wit leaders Barcelona wey get two points ahead of Real Madrid for di top of di division. Meanwhile, Portugal Primeira Liga go resume for 3 June and Portimonense go play against Gil Vicente and Famalicao wey dey host leaders Porto.La Liga go fit resume behind closed doors from 8 June according to Spain Prime Minister Pedro Sanchez. Meanwhile, Portugal's Primeira Liga will resume on 3 June, with Portimonense against Gil Vicente and Famalicao hosting leaders Porto. Porto lead rivals Benfica get 10 rounds left. https://www.bbc.com/pidgin/tori-52785723 +sports Manchester United vs Man City: Kick-off, prediction and oda tins to sabi for Manchester derby Premier league match Manchester City neva win Premier League derby since April 2019 but as dem dey play against fellow Manchester City, fans go look to see weda Ole Gunnar Solskjaer side 5 - 0 defeat ova Liverpool na fluke. Many pipo dey tok di issue na inconsistency of gameplay. As e be so, City dey play very restrictive game meanwhile United dey play dia game around Ronaldo. United bin bounce-back afta dem knack Spurs last weekend. Wetin go make di game sweet join be say United don perform well against Pep Guardiola's side of late. In fact, dem dey unbeaten for four Premier League meetings against City, even thou dis one na before Ronaldo join United. Di match dey scheduled to start by 12.30pm GMT (dat go be 1:30pm Nigerian time) kick-off on Saturday 6 November, 2021. Old Trafford for Manchester go host am. United go need show say dem fit meet di challenge wey City go bring especially afta dia 2-2 game wit Atlanta, if no dem go lose ground for di Premier League title race. 1-1 draw. Wia to watch Na Cable Company Supersports wey dey for DSTV go broadcast di match live. If you dey reason to watch am for Nigeria and Ghana. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59190729 +sports African Sports Personality of the Year 2021 award shortlist - See how you fit vote "Di shortlist for BBC African Sports Personality of di Year 2021 award don come out. Di six contenders for di award na panel of journalists from Africa and di United Kingdom choose dem. Di panel select shortlist based on di best African sporting achievements wey dey on di international stage for 2021 (between January and September). Dem also take into account di impact of di pesin achievement beyond dia particular sport. Di nominees are: You fit vote for di winner below. Voting go close by 23:59 GMT on Sunday, 19 December and dem go announce di winner of di award on Friday, 7 January 2022 on Focus On Africa television and radio and on BBC Sport website. Dis na wetin you need sabi about about di six contenders wey dey in di race to win di award: Country: Kenya Age: 37 Discipline: Marathon runner Im arguably be di best marathon runner of all time and dis year, Eliud Kipchoge cement im status over 26.2 miles afta e win im second successive Olympic gold for di event. Just di third person to successfully defend im Olympic marathon title, dem later name di Kenyan International Olympic Committee best male athlete of di Games. Im win for Tokyo mean say im don win 13 of di 15 major marathons wey im don run since e step up to di distance for 2013, Kipchoge add to im CV which include di official world record of 2:01:39 im set for Berlin for 2018. At 36, im bin be di oldest Olympic marathon winner since Portugal Carlos Lopes (then 37) for 1984 and record di greatest winning margin since 1972. Country: Kenya Age: 27 Discipline: Middle-distance runner Faith Kipyegon set Olympic record for Tokyo as she defend 1500m title wey she first win for Rio de Janeiro for 2016. Di Kenyan dedicate di win to her three-year-old daughter, wey she credit wit giving her extra motivation afta she take 21-month break from di sport. Di dedication na di more significant one to her since Kipyegon na only di third athlete to retain her Olympic title after she born between Games (along wit Australia's Shirley Strickland, for 1956, and Cameroon Francoise Mbango, for 2008). Before her ogbonge display for Japan, she bin don set world-leading time of 3:51.07 - di fourth fastest time in history - in Monaco in July for di Diamond League, event wia dem crown her as dis year's champion for September. Afta her Olympic record, she now dey target di world record. Country: South Africa Age: 19 Discipline: Long jumper and 200m runner Ntando Mahlangu win im first Paralympic medal wen im dey just 14, wen e win silver for di T42 200m for Rio Games for 2016 - just two years afta im start di sport. Dis year, im add to im collection wen e win gold for both di men's 200 metres (T61) and long jump (T63) for Tokyo. Di jump wia im secure gold set new world record of 7.17m - even though im only start to train for di event six weeks before di Games. With bright future on di track, di youngster - wey dem amputate e legs, because im get under-developed limbs, qwn im dey 10 years - dey combine im athletic exploits wit im academic work. For April, im set world record of 22.94s for di men's 200 metres. Country: Namibia Age: 18 Discipline: Sprinter ""Di best race of my life"" - dat na how Christine Mboma describe her performance for Tokyo 2020 as she become di first Namibian woman to ever stand on Olympic podium. Winning her kontri first medal for 25 years, di teen take silver for di 200m, she finish behind Jamaica five-time Olympic champion Elaine Thompson-Herah. Mboma time of 21.81 seconds na di den fastest time ever run by woman under di age of 20. She go on to become di 200m Diamond League champion for September in Zurich, wia her time of 21.78 set both anoda under-20 world record and new African record. Di 18-year-old only begin focus on di 200m earlier dis year, afta dem stop her from di 400m by global governing body World Athletics because she naturally get high testosterone hormone levels. Country: Senegal Age: 29 Discipline: Football goalkeeper Edouard Mendy don impress for Stamford Bridge since im sign for Chelsea from French side Rennes for September 2020 and bin dey key for di west London club Champions League success for May. Im keep record-equalling nine clean sheets as dem lift di trophy for im first season for di competition. Mendy also make history as im become di first African goalkeeper to play for Champions League final and di first for Europe ogbonge event since Zimbabwe Bruce Grobbelaar appear for di 1985 final of di European Cup, di tournament former name, for Liverpool. Mendy 19 clean sheets last season across both di Champions League and Premier League see am pick up di Uefa Goalkeeper of 2020-21 award. Di Uefa Super Cup winner don also collect nomination for Fifa best goalkeeper of 2021, but di man who collect FA Cup runners-up medal for May recently miss out on winning France Football magazine Yashin Trophy for di best goalkeeper in Europe. Country: South Africa Age: 24 Discipline: Breaststroke Tatjana Schoenmaker make waves for Tokyo wia she no only take home gold and silver for South Africa, but she set new world and Olympic records for 200m and 100m breaststroke respectively in di process. In doing so, she win South Africa first Olympic medal for women swimming since 2000 and end her kontri 25-year wait for female Games gold for pool as she finish first for di 200m final. Schoenmaker almost quit di sport for 2016 afta she miss out on qualification for Rio Games by one-hundredth of a second. But she stick wit di sport and don since collect multiple national and continental records, two Commonwealth Games golds and one world silver medal. ""Di next challenge na, how I fit improve on myself? I dey excited to see wia my swimming go get to,"" she tok." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59540799 +sports Lionel Messi: Barcelona striker wan play for US "Barcelona captain Lionel Messi say e hopes to one day play for di United States but no dey sure of e future wen e contract go end for June. Di Argentina forward, 33, fit begin negotiations wit overseas clubs for January. Guess work over e future don dey go on since e hand in a transfer request for August 2020. ""I no know wetin I go do yet,"" na so Messi tell Spanish television channel La Sexta. ""I go wait until di season end. I go like to play for di United States and experience life and di league there, but ultimately come back to Barcelona in some capacity one day. ""Right now di most important thing na to focus on di team and finish di season well, to focus on trying to win trophies and to no dey distracted by other things."" Barcelona, wey no win any trophy last season, dey fifth for La Liga after their worst start to di league campaign in 33 years. Since im join Barcelona at di age of 13, Messi don become di club record goalscorer, im don win 10 La Liga tiles, four Champions League and di Ballon d'Or - award for di world's best player - six times. Im controversial summer request to leave Barcelona follow clash with club president Josep Maria Bartomeu, wey resign for October. Messi describ Bartomeu time for di club as ""a disaster"". ""Na difficult moment for di club, for everyone, but those inside di club know say we dey in a really bad situation, things dey very bad and e go dey difficult to return di club to where dem used to be,"" im add." https://www.bbc.com/pidgin/sport-55464365 +sports Morocco 3:0 Spain - How Morocco knock out Spain on penalties to enta quarter-finals "Di first surprise of di knock out stages of di Fifa World cup don happun o! Morocco wey be di only African representatives for di World Cup beat former World Champions Spain 3-0 on penalties, afta regulation time and extra time end 0-0 Morocco wey break dia 36 year old record to qualify for di last 16, break anoda record as dem reach di last 8 for di first time for dia history. Di match tie wrapper from starting to ending as both sides play for 115 minutes witout goal. Morocco goalkeeper Bono na di hero of di day as e save three penalties wey Spain play. Morocco don become di first African kontri since Cameroon for 1990 to play five straight matches witout any loss for di World Cup. Morocco enta di quarter-finals for di first time ever. Dem be di fourth African team to reach dat stage afta Cameroon for 1990, Senegal for 2002 and Ghana for 2010. 121 min: Miss for Spain! Sergio Busquets of Spain fire di ball to di left side of di goal post but Morocco goalkeeper save am Goal!!! Achraf Hakimi score for Morocco!\nMorocco don win!!!! 121 min: Miss for Spain! Carlos Soler miss im\nPenalty as Morocco goalkeeper Bono save di ball.\n121’ Penalty Save! Badr Benoun of Morocco play di penalty to di bottom left corner but Unai Simon save am. 121 min: Penalty shootout! game of lottery Morocco go take di first penalty Goal! Abdelhamid Sabiri of Morocco score!\nMiss! Pablo Sarabia miss as im shot di ball to di right corner of di post.\nSpain miss dia first penalty\nGoal for Morocco! Hakim Ziyech score! 120+4 Second period of extra-time don end 120+3 No luck!\nPablo Sarabia of Spain fire shot from close range but e hit di left post! Three minutes added time. 120 min: Substitution for Morocco\nAzzedine Ounahi don replace Badr Benoun 118 min: Substitution for Spain\nPablo Sarabia don replace Nico Williams. 118 min: Nico Williams of Spain whip di ball inside di penalty area but one defender hit am comot. 117 min: Alvaro Morata play thru ball but e hit am too much. 115 min: Walid Cheddira of Morocco break free but Spain player clear di ball! 111 min: Romain Saiss of Morocco dey collect treatment afta e pick up minor injury but I’m don enta pitch back. 109 min: Sergio Busquets (Spain) no fit see any of dia player for di box wit one long pass. 106 min: Carlos Soler (Spain) beat di challenges inside di box but Im pace too fast for di pass e give Ansu Fati 105+2 First period of extra-time don end 105 min: One minute added time 104 min: Beta pass from Walid Cheddira of Morocco for space inside di box but goalkeeper Unai Simon no allow am. 103 min: Rodri(Spain) waste opportunity as e shoot di ball over di bar! 101 min: Ansu Fati of Spain play short corner afta Alejandro Balde block one shot from inside di box to win corner kick. 100 min: Alvaro Morata of Spain chip pass into di box but one of di player cut di pass short. Alejandro Balde replace Jordi Alba Ansu Fati don replace Dani Olmo 98 min: Substitution for Spain 95 min: Walid Cheddira of Morocco dey offside as e dey make run to the opponent area. 93 min: Rodri of Spain play long ball across di field but e miss di target 91 mins: First period of Extra-time don start 90+6 Second half don end 90+5 Serious defending from Morocco as Spain dey bombard dia goal post for di last few seconds. 90+3 Romain Saiss dey offside as e dey try to make a run. Spain dey put plenty pressure on Morocco, Morocco too dey make goal attempts for Spain area. 90+1 Carlos Soler play free kick near Alvaro Morata but e go over di bar! 90 mins Five minutes added time 90 min: Yellow card for Morocco\nRomain Saiss collect yellow card as e bring down Spain player. 89 min: Alvaro Morata of Spain dey offside as e wan try enta di box to score. 83 min: Substitutions for Morocco\nYoussef En Nesyri don comot Abdelhamid replace am\nSelim Amallah don comot Walid Cheddira don enta.\nYahaya Attiat-Allal replace Noussair Mazraoui. 82 min: Miss!\nMorata miss one-on-one as e play di shot wide! 81min: Spain play dia corner kick sharp sharp! 80 min: Nico Williams of Spain cross di ball to try score but Morocco defend clear am. 78 min: Dani Olmo of Spain make goal attempt from di edge of di area but do shot go over di bar! 77 min: Aymeric don collect yellow card for strong challenge on Morocco player. 75 min: Substitution for Spain 75 min: Nico Williams don replace Ferran Torres. Spain players dey exchange short short passes to try create opportunity for dem to shoot. 73 min: Alvaro Morata too enta offside is im bin try to carry di ball go forward. 72 min: Romain Saiss of Morocco fail to beat di offside trap as linesman raise im flag up 68 min: Plenti players gada near post dey wait for corner kick cross but Dani Olmo play am short. 66 min: Substitution for Morocco.\nSofiane Boufal don comot Ez Abde replace am. 63 min: Gavi don comot too, Carlos Soler don enta First substitution for Spain!\nMarco Asensio don comot, Alvaro Morata replace am Substitution: 62 min: Pedri (Spain) play di free kick and start di play again wit short pass, afta Nayef Aguerd foul Spain player. 58 min: Referee Fernando Rapallini blow foul afta Hakim Ziyech (Morocco) bring down im opponent. 55 min: Dani Olmo (Spain) play di free kick wey land ontop of di net 54 min: Achraf Hakimi bring down im opponent, referee blow foul plus give free kick. 51 min: Dangerous play wey Achraf Hakimi (Morocco) make referee blow im whistle for foul. 48 min: Marco Asensio (Spain) play di free kick into di penalty area but Morocco defence ready to clear am out. 47 min: Ferran Torres(Spain) and Mazraoui pull each oda as dem dey chase di ball, referee stop play for foul. 45 min: First -half don end 45 min: Marco Asensio collect short pass from Ferran Torres (Spain) but Morocco defence clear am. 42 min: See beta ball from Sofiane Boufal , e give Nayef Aguerd for close range but e head am wide! 40 min: Morocco defenders dey work well well as Gavi pass ball to di penalty box but dem clear am. 39 min: Pedri(Spain) pass di ball give Marco Asensio but one of Morocco defenders clear di ball. 36 min: Dani Olmo(Spain) try to make a run by imsef but Morocco player block am. 33 min: Nearly! Noussair Mazraoui (Morocco) get beta position to score but Unai Simon save di ball 32 min: Foul! Rodri of Spain challenge Morocco player, referee Fernando blow foul. 30 min: Linesman raise flag to signify offside before Sofiane Boufal (Morocco) continue 27 min: Marco Asensio (Spain) no dey waste time to shoot inside di box afta a near pass from Jordi Alba, but e miss di left post. 25 min: Ferran Torres (Spain) drive past Di last defender but referee stop di game afta linesman signal offside! 22 min: Hakim Ziyech (Morocco) try to find im teammate outside di box but Spain no dey give dem breathing space. 21min: Achraf Hakimi of Morocco send one cross inside di box but Spain defence clear di ball. 19 min: Ayemeric Laporte (Spain) play long ball to Jordi Alba but e put too much power come troway di ball. 17 min: Offside for Hakim Ziyech (Morocco) 15 min: Noussair Mazraoui (Morocco) play beta cross into di box but Spain goalkeeper Unai Simon catch am. 13 min: Rodri (Spain) tackle Morocco player badly referee Fernando Rapallini blow foul. 12 min: Achraf Hakimi of Morocco take di free kick e fire strong shot from di middle but di ball go over di bar! 10 min: Gavi of Spain collect ball from dia opponent, im para as referee Fernando Rapallini blow foul. Morocco get free kick. 9 MIN: Gavi of Spain dey ginger too much for di attack sotay e foul im opponent 7 MIN: One of di defenders react for di last minute to to block one pass from Sofiane Boufal of Morocco 5 MIN: Hakim Ziyech of Morocco make good run pass im man but e no fit keep di ball in play. 3 min: Spain dey play well so far, dem dey put Morocco under pressure. 1 min: Match don start Today na today! for di Round of 16 matches between Morocco and dia neigbours Spain. Di Education City Stadium go host dis ogbonge match wey go break record for Africa if Morocco win. Morocco na di only African representative wey still dey for di tournament, and di eyes of football fans for di entire continent go dey for dis match. Di north African side end dia 36 years of World Cup disappointment wen dem qualify for di last 16. Di Atlas Lions of Morocco shock evribody for Group F wen dem top di Group wit Seven points. Morocco neva lose any match for dia last four World Cup, and dem fit become di first African kontri since Cameroon for 1990 to play five straight matches witout any loss for di World Cup. Di success of Morocco na sake of dia beta defence, na only one goal dem conceded for di group stage. No kontri for di tournament do am. E also increase dia clean sheet to six out of dia last seven matches. Morocco coach, Walid Regragui don ginger di players to “target di sky” e say make dem dream to win di cup. Di Atlas Lions beat Belgium wey be number two for Fifa world ranking. Di record dey give dem mind say dem fit still beat Spain today. One of Morocco top stars and wing-back Achraf Hakimi say im tink say im side fit ""pull off anoda surprise"" against Spain. Di 24-year-old, wey dem born for Madrid, Spanish capital, wey don also play for Spain Junior teams before say ""Sometin dey unique to play for your kontri and especially now wey we dey make history. ""E dey incredible to see di way pipo dey live wit us, and di energy dey transmit to a lot of us and e dey give us strength to continue and look to do great tins."" E tell BBC. Hakimi add say im side – wey dem deny World Cup victory over Spain in di group stages four years ago wen Iago Aspas score injury-time equaliser - ""deserve a little respect"". ""Four years of experience since  mean say I don come wit a more mature mentality,"" im add. ""Spain na one of di top-five teams and dem dey always come to di World Cup to win but our coach don also teach us to get a winning mentality. E no mata who we dey play against. We go play our way and try to beat dem. E add. Wetin Spain Coach tok Spain coach Luis Enrique hope say di ' ""homework"" im give im players to practice 1,000 penalties go pay off against Morocco di World Cup last 16. Enrique say im give im players di task over di last year becos im expect spot-kicks for di knockout stages of di tournament for Qatar. Italy remove Spain for di semi-finals of last year Euros wit penalty. ""I imagine say dem don do dia homework,"" Enrique tok. ""Over a year ago, for one of di Spain camps, I tell dem say dem need to come hia wit at least 1,000 penalties taken,"" Enrique tok. ""If you wait until you come hia before you practice penalties... [e no go dey enough]. ""Na moment of high tension, a time to show your nerve and say you fit shoot di  penalty di way you decide, if you don practice am one thousand times. ""E say  a lot about each player. E dey trainable, manageable, how you manage di tension. Luck for penalty don dey reduce - di goalkeepers get more influence. ""We get a very good goalkeeper, any of di three go do very well for dis situation. Every time we finish training, I see say plenty players dey take penalties."" Luis Enrique say im get full squad of 26 players wey im go choose from afta Cesar Azpilicueta recover from im knock against Japan. All Morocco players also dey kampe and Hakimi fit play too afta im well from ankle injury. Match Facts Morocco Bono, Hakimi, Aguerd, Saïss, Mazraoui, Ounahi, S Amrabat, Amallah, Ziyech, En-Nesyri, Boufal Spain Simón, Llorente, Rodri, Laporte, Alba, Gavi, Busquets, Pedri, F Torres Asensio, Olmo" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjenzn3y3n3o +sports De Jong make U-turn on Man Utd, Bayern dey eye Kane "Bayern Munich chief executive Oliver Kahn don describe Tottenham and England forward Harry Kane, 28, as ""absolute top striker"" and ""a dream of the future"" after dem agree to sell Robert Lewandowski, 33, to Barcelona. (Star) Barcelona don turn dia attention to 23-year-old Sevilla and France defender Jules Kounde, who also dey linked to Chelsea,after dem reach deal for Poland striker Lewandowski. (Marca) Netherlands international Frenkie de Jong dey oppose to joining Manchester United or any English club, but di 25-year-old Barcelonamidfielder go consider move to Bundesliga champions Bayern Munich. (Sport - in Spanish) Tottenham dey prepared to pay 17m euros (£14.4m) for Barcelona forward Memphis Depay, but di Spanish club want 20m euros (£17m), although di 28-year-old dey reluctant to leave the Nou Camp. (Sport - in Spanish) Chelsea and Albania striker Armando Broja go join West Ham on season-long loan. Di Hammers bin want sign the 20-year-old on a permanent deal but di Blues no gree sell the player wey spend last season on loan at Southampton. (Mail) Already wearing Barcelona's colors, Robert Lewandowski don join the squad in Miami on Sunday ahead of his medical and the signing of his contract.(Sky) AC Milan still dey hunt for Portugal international Renato Sanches. Paris-Saint Germain dey slow to make dia move for di Lille midfielder, leaving AC Milan in pole position to swoop in for the player.(Gazetto dello Sport) Manchester United dey keep tabs on Brentford striker Ivan Toney and fit make move for di Brentford striker, (Sunday Mirror) Leeds United want more than £35million to sell Jack Harrison as interest from Newcastle United dey strong, reports the (Mail on Sunday) Rangers defender Calvin Bassey don arrive Amsterdam to complete im move to Ajax. (Sky)" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c517yew7dqpo +sports Novak Djokovic win ninth Australian Open, beat Daniil Medvedev in straight set "Novak Djokovic collect im men's title for Australian Open after he overpower Daniil Medvedev. Top seed Djokovic win di match 7-5 6-2 6-2 to claim im 18th Grand Slam overall - with only Roger Federer and Rafael Nadal as di players wey get pass am. Di 33-year-old Serb never lose final for Melbourne Park and and dis na di third time im dey Medvedev in a row. After collecting im trophy, Djokovic say: ""I love you each year more and more. Di love affair just dey grow."" After losing to Nadal for di 2019 US Open final, pipo reason am say di Russian fit beat Djokovic. Djokovic win di game after one hour and 53 minutes with one backhand overhead volley. E come lie down ontop im back for di blue court. After e go hug im coach Goran Ivanisevic and di rest of im support team." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56136714 +sports Caf Awards 2019: Asisat Oshoala want create her own history "Nigeria Super Falcons captain, Asisat Oshoala say she want 'create her own history' afta she win di 2019 Confederation of African Football (Caf) Women Player of di Year award on Tuesday. Dis award wey Oshoala win for di fourth time don make her equal di record of fellow Nigerian Perpetua Nkwocha. Oshoala year include goal for Women World Cup to help Nigeria reach di last 16 inside France and 10 goals for 13 appearances afta she join Spanish side Barcelona for February. ""I dey really excited - proud of myself, four times na something to always remember,"" she tell BBC Sport Africa. ""E dey keep me going but of course work still dey to do, I want to create my own history and not just equal someone else record - I go give my best to create my own."" Oshoala, wey claim di award for 2014, 2016 and 2017, bin dey up against Valerenga and Cameroon forward Ajara Nchout plus last year winner Thembi Kgatlana of Beijing BG Phoenix and South Africa. She say she no dey take di fourth win for granted. ""I dey actually tense about dis, but na historical night for me,"" she tok Nkwocha, wey be five-time Women Africa Cup of Nations winner, claim di award back-to-back for 2004 and 2005 and again for 2010 and 2011." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51037498 +sports Update on Afghanistan: Australian government help evacuate Afghan women footballers "Di Australian government don evacuate more than 50 women footballers and athletes and their dependents from Afghanistan following appeal by world bodies Fifa and Fifpro. One statement by di international footballers' federation Fifpro thank Australia for di role wey dem play. Afta di Taliban retake Kabul, many Afghan sportswomen bin go into hiding. Di statement tok say work still dey needed to settle di women abroad. ""Dis young women, both as athletes and activists, don dey in a position of danger and on behalf of their peers around di world we thank di international community for coming to their aid,"" Na so Fifpro tok about di evacuation wey carry more than 50 pipo according to news sources including ABC. ""We urge di international community to make sure say dem receive all di help dem need. Many athletes still dey risk for Afghanistan and we dey make every effort to offer them support."" Afghanistan former football captain Khalida Popal describe di evacuation of di group, wey include members of di Afghanistan national women's football team and their youth team, as ""important victory"". However, she caution say more work still dey needed in saving others from uncertain fate. ""Di women footballers don dey brave and strong for moment of crisis and we hope dem go get better life outside Afghanistan,"" Popal tok, 34. ""Women football na family and we must make sure say everyone dey safe."" Fifpro general secretary Jonas Baer-Hoffmann say to evacuate di women bin be ""difficult process for everyone wey dey involved"", im add say: ""Our hearts go out to all di others wey still dey stranded for di kontri against their will."" Last week, football world governing body Fifa join Fifpro write to governments around di world as dem request assistance, as players fear for their lives. ""I never dey able to sleep, I don dey cry and feel helpless,"" Popal tok. When di Taliban seize power for Afghanistan for di late-1990s, dem bin prevent girls from attending school after di age of 10 and many bin dey forced into child marriage. Under di oppressive rule, wey ended for 2001 after military campaign wey US armed forces spearhead, women no fit leave dia house alone and dem bin force dem to wear burqa." https://www.bbc.com/pidgin/sport-58322692 +sports Sierra Leone striker run comot Sweden sake of cold "Sierra Leone striker Musa Noah Kamara don end im contract with Trelleborgs afta just one week wey join dem. Di club say dem end di 19-year-old three-and-half year deal sake of ""personal reasons"". For inside statement wey di club release for dia website, di club say Kamara wan return back to im kontri for personal reasons. Kamara tok say im wan return to Freetown as im no fit cope with di cold weather for Sweden. For Sierra Leone 2019, Premier League di striker score 15 goals and finish as highest goal scorer to help im club East End Lions become champions." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49399098 +sports Messi set new record to lead Argentina into World Cup final over Croatia Argentina and Croatia no dey new to each oda for international football. Na di same way di captains of di two teams; Lionel Messi and Luka Modric take sabi dia sef both at national team and club level – take sabi dia sef. Both teams go meet for di first semi-final match of di Qatar 2022 Fifa World Cup match for di Lusail Iconic Stadium. Argentina 3-0 Croatia 90+6mins: FULL TIME. 90+4mins: Lovro Majer launche di ball from di resulting corner, but one of di defenders clear di threat. 90+3mins: Rough tackle by Exequiel Palacios. Di referee blow for a foul. 90mins: 5 minutes of added time. 89mins: Great touch by Lovro Majer as e receive a good pass deep inside di box Messi set new record as e Argentina into World Cup final 87mins: SUBSTITUTION. Angel Correa enta for Alexis Mac Allister. Juan Foyth for enta Nahuel Molina 86mins: Lovro Majer take di ball to di corner 85mins: Di attendance na 88966 84mins: Alexis Mac Allister receive brilliant pass and e waste good opportunity 83mins: Marko Livaja commit serious foul. Ref blow 81mins: SUBSTITUTION. Lovro Majer enta for Luka Modric 78mins: Mislav Orsic try im luck but di attempt go wide. 76mins: Ivan Perisic attempt to surprise di keeper wit shot from distance, but e lack accuracy. 74mins: SUBSTITUTION. Exequiel Palacios enta for Rodrigo de Paul. Paulo Dybala enta for Julian Alvarez 74mins: Dangerous play by Nicolas Tagliafico 73mins: Ivan Perisic slam di ball from mid-range free kick towards di net! 72mins: SUBSTITUTION. Marko Livaja enta for Andrej Kramaric the pitch and comes on. 71mins: YELLOW CARD. Nicolas Otamendi chop card for rough tackle Argentina 3-0 Croatia 69mins: GOAL. Julian Alvarez make am 3 for Argentina 68mins: YELLOW CARD. Cristian Gabriel Romero chop card 67mins: Julian Alvarez commit rough challenge and ref Daniele Orsato blow for foul. 66mins: Rodrigo de Paul swing a cross, but defender clear am comot 65mins: Lionel Messi clearly hold im opponent to stop am from getting di ball. 64mins: Josip Juranovic rob im opponent of di ball and explode in anger wen Daniele Orsato blow for a foul. 63mins: Dejan Lovren almost score wit a header afta a cros from a free kick but Emiliano Martinez save am 62mins: SUBSTITUTION. Lisandro Martinez enta for Leandro Paredes. 61mins: Short on Target – Argentina 6:0 Croatia 58mins: Julian Alvarez make reckless foul in order to win di ball from im opponent. Ref Daniele Orsato blow for foul. 58mins: MISSED CHANCE. Lionel Messi receive good pass plus opportunity to play short but Goalkeeper Dominik Livakovic make fine save 57mins: Nahuel Molina waste a good opportunity 56mins: Julian Alvarez attempt to find im teammate wit a short pass into di box. Enzo Fernandez collect di ball, but di Croatina defence stop am. 55mins: Dejan Lovren fail to find im teammate across di pitch wit a long ball.. 54mins: Rodrigo de Paul intercept pass but e rough im opponent. 53mins: Nikola Vlasic attempt to find im teammate wit a pass from outside di box, but di opposition defence react well. 50mins: SUBSTITUTION. Bruno Petkovic enta for Marcelo Brozovic. 50mins: Nicolas Tagliafico dey was too rough for im attempt to get di ball from im opponent. 49mins: Dominik Livakovic block a long-range effort from Leandro Paredes towards di middle of di goal. 48mins: Luka Modric send ball into di penalty area from a free kick. 47mins: Nicolas Otamendi carelessly slide into di leg of im opponent and ref Daniele Orsato blow for foul 46mins: SUBSTITUTION. Mario Pasalic enta for Nikola Vlasic. Mislav Orsic enta for Borna Sosa Argentina 2-0 Croatia 45mins: Second Half don start Argentina 2-0 Croatia 45+5: First Half don end 45+5mins: Marcelo Brozovic commit rough foul. Daniele Orsato stop di game and call for foul. 45+3mins: Ivan Perisic attempt to create a dangerous situation in front of goal by sending a cross into di box, but the defence easily deal wit am. 45+2mins: 4 additional minutes 45+1mins: Luka Modric gets on di end of a good pass and from mid-range. E play shot but Argentina defender block am. 42mins: Lionel Messi take d corner kick. 41mins: Rodrigo de Paul collect pass on di edge of di box and play shot but e go over. Argentina 2-0 Croatia 39mins: GOAL! Julian Alvarez make am 2 for Argentina 38mins: Josip Juranovic send pass into di box, but di opposition defence dey alert Argentina 1-0 Croatia 36mins: Julian Alvarez too use orceful wit im tackle and Daniele Orsato interrupt di game to signal free kick. 34mins: GOAL! Lionel Messi. Argentina 0-0 Croatia 30mins: Rodrigo de Paul whip di ball in but e fails to reach any of im teammates. 29mins: Luka Modric put cross into di box from di free kick, but di defender reach dia first. 28mins: Croatia looking strong for back. 27mins: Nicolas Tagliafico give away foul for a fierce tackle on opponent. 26mins: Enzo Fernandez wey Liverpool wan sign just get good opportunity from long range. Dominik Livakovic save do shot. 25mins: Nicolas Tagliafico attempt to send over a cross in order to find one of im teammates, but opposition defender stop di danger. 22mins: POSSESSION Argentina 35:65 Croatia. 19mins: Ref stop di game for some minutes afta Cristian Gabriel cause foul. 17mins: Dejan Lovren (Croatia) receive cross in di box and attempt to shoot, but mishit di ball and miss goal. 16mins: Josip Juranovic try to send a pass but dem block am. 13mins: Luka Modric makes rough challenge and di referee blow for foul. 13mins: Borna Sosa fail to find any of im teammates inside di box 12mins: Borna Sosa slides a pass forward, but one of di defenders cut am out. 9mins: Croatia dey showed great team chemistry. 4mins: Rodrigo de Paul send beta cross into di area, but Dominik Livakovic intercept di ball. 3mins: A cross by Nahuel Molina from di side of di pitch flies into di box. Argentina 0-0 Croatia 1min: KICK OFF Argentina: E Martínez, Molina, Romero, Otamendi, Tagliafico, De Paul, Fernández, Paredes, Mac Allister, Messi, Álvarez. Croatia: Livakovic, Juranovic, Lovren, Gvardiol, Sosa, Modric, Brozovic, Kovacic, Pasalic, Kramaric, Perisic Dis na di third World Cup meeting between Argentina and Croatia, and first for di knockout stages. Argentina win 1-0 for 1998, before Croatia 3-0 win in di 2018 tournament for Russia. Argentina dey look to reach di World Cup final for di sixth time, na only Germany don make am to di final, eight times. Argentina don win just one of dia past seven World Cup games against European sides. Croatia na World Cup finalists for 2018 – dem lose to France. Dem fit become fourth European nation to reach consecutive World Cup finals afta Italy (1934, 1938), Netherlands (1974, 1978) and Germany (1982, 1986, 1990). Croatia don win all four of dia penalty shootouts for di World Cup, knocking out Japan and Brazil in di last 16 and quarter-finals for 2022 respectively. Di only nation to win more penalty shootouts for di World Cup na Argentina, wit five. Argentina go dey without di suspended Marcos Acuna and Gonzalo Montiel. Tagliafico go come in for left-back. However, both Angel di Maria and Rodrigo de Paul go dey fit to play for Scaloni side. Croatia boss Dalic no get injury or suspension concerns. Di coach go fit select from a fully fit squad afta Borna Sosa and Mislav Orsic recover from sickness. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjlrgn5yzego +sports How defending champions Super Falcons chop first defeat from Bayana Bayana for Wafcon 2022 "Di Bayana Bayana of South African don beat Nigeria 2:1 for di Women’s Africa Cup of Nations match for Moulay Hassan Stadium, Morocco. Na Jermaine Seoposenwe score di first goal for South Africa for 61 minutes, while Hilda Tholakele Magaia make am 2:0 for 63 minutes. Rasheedat Ajibade of Super Falcons na she score for Nigeria for 90+2 minutes to make di match end for 2:1. Today match between Nigeria and South Africa na di opening match for Group C wey many pipo see as di clash of di titans sake of di rivalry between Nigeria and South Africa. As e be so, Bayana Bayana don get di important three points and dia focus na to continue di way wey dem take start di tournament. Wit dia win today, Bayana Bayana dey tell Super Falcons say make dem chop dessert ontop di ""hot meal"" wey dem give dem last year for Mobolaji Johnson Arena for Lagos, southwest Nigeria. Di ""hot meal"" na for di final match of di first edition of di Aisha Buhari Women’s Tournament where dem sama Nigeria 4:2. Bayana Bayana bin enta four WAFCON finals but dem no win any of dem, and dem won ensure say na for Morocco dem go rewrite dia history. Super Falcons wey be defending champions reach nine WAFCON finals and win all of dem. Apart from Nigeria and South Africa wey dey Group C for di tournament, oda kontris wey dey dia na Burundi and Botswana. Nigeria next match na against Botswana on Thursdday 7 July, while South Africa go play against Burundi on di same day." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cglx2l546rro +sports Tariq Lamptey, Inaki Williams, foreign players wey switch to play for Ghana "Black Stars dey on mission to scout some of de best players across de world wit Ghanaian origin to join de national team. Ghana go through one of de poorest AFCON tournaments for Cameroon before dem manage beat Nigeria to qualify for de World Cup. De Black Stars after changing dia technical team with support from Ghana Football Association manage get some big names to join de squad ahead of de 2022 Fifa World Cup in November. Dis be some of de players wey make switch or finally decide to play for Ghana. Latest person to join de Black Stars be former English player, Tariq Lamptey. Taking to de social media handles, Black Stars announce say de player make de switch from England. “E be just a matter of time...Welcome home Tariq” Black Stars social media handle talk. Recently, Tariq Lamptey visit Ghana wit en family after de end of de English Premier League. He talk to local media say he dey Ghana for ""some sun and family time."" During en visit, he take time off de wtach de Black Stars game against Madagascar. Ghana Football Association start dey pursue de London-born defender since around 2020, but football pundits say de World Cup be major encouragement for de lad to join de Black Stars. Lamptey, get two Under-21 caps dey qualify for Ghana through en parents. Lamptey en father, Ahmed according to GFA play major role in de decision of de player to switch allegiance den play for Ghana. Talks be say former Brighton manager Chris Hughton, now de technical advisor for Black Stars also play role in de player decision to switch from England to Ghana. Top Atletico Bilbao striker, Inaki Williams announce en decision to represent Ghana. He make de announcement on en Twitter page today after months of speculation which dey link de player to Ghana ahead of de 2022 Fifa World Cup. He get en first international call up to represent Spain under-21 squad in March 2015. Despite playing for Spain junior national team, he no make major competitive appearances in dia national team side. In 2021 when dem ask am about de possibility of playing for Ghana he talk say “my parents dey come from Accra, dem no born or raise me there, my culture dey here.” But on July 5, 2022 he make u-turn on en decision to represent Ghana by wearing de Black Stars ahead of de 2022 Fifa World Cup. “De moment come for me to find my origin within myself with Africa den Ghana” Inaki talk inside video. “I want return small part of everything sake of Ghana play significant role in becoming who I as a person” he add. He conclude by saying “today new challenge dey begin. From now on I go defend Ghana T-shirt with my all. I go give my best, I be one of de Black Stars.” GFA confirm say other players make ready for call ups while other switch nationality to join de Black Stars. GFA Boss, Kurt Okraku talk say “Mohammed Salisu, Stephan Ambrosius, Patrick Pfeffer, and Ransford Yeboah all dey available for national selection.” Meanwhile one of de big Ghanaian names who reject previous calls to join de Black Stars Mohammed Salisu finally agree to play for Ghana. De Southampton player be one of de best defenders in de EPL, de u-turn decision dey add more talent to de senior national team." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjk0pz72exzo +sports Champions League result: Chelsea, Barcelona, Juventus and Sevilla book dia place for next round Chelsea, Juventus, Sevilla and Barcelona don book dia place for di knockout stages of di 2020/2021 Champions League season. Dis na becos all four clubs don record points wey di other teams for dia group no go fit equal wit two matches remaining. Wetin remain now for dis four clubs na to know who go top dia group at di end of all group matches. Chelsea progress to di next round wit 2-1 win away at Rennes thanks to late goal from substitute Olivier Giroud. Callum Hudson-Odoi bin give di blues di lead for first half before Rennes striker Sehrou Guirassy equalise for di 85th. For di other game for Group E, Sevilla also score late goal to overcome Krasnodar 2-1 to book dia place alongside Chelsea for di next round. Ivan Rakitic and Munir El Haddadi na dem score for Sevilla while Wanderson bin equalise for Krasnodar. Goals from Sergino Dest, two from Martin Braithwaite and one from Antoinne Griezmann see Barcelona stroll to comfortable 4-0 win away against Dynamo Kiev. Meanwhile Juventus get to rely on late goal from substitute Alvaro Morata to break di strong head of Ferencvaros, as di Old Lady beat dem 2-1. Cristiano Ronaldo na him score Juve first goal after Ferencvaros bin take di lead through Myrto Uzuni. Di oda group games go kickoff on Wednesday. https://www.bbc.com/pidgin/sport-55054624 +sports Match report for African teams last friendly match inside September for Qatar 2022 Five African teams wey dey Qatar 2022 World Cup play international friendly match on Tuesday. Ghana na di only African team wey win match out of di five teams. Dis tori go torchlight di last friendly match involving dem ahead of di World Cup wey go happun for November dis year. Di Black Stars defeat di South American nation Nicaragua 1-0 on Tuesday night. Di match take place for di Spanish city of Lorca. Na part of di West African team preparation for di World Cup. Di highlight of di game na wen di talented teenage midfielder Abdul Fatawu Issahaku score fine goal from di edge of DI box for 34th minute. Dat goal give Ghana victory ova di South Americans. Di Black Stars, bin make some changes to di team from Friday wey lose 3-0 to Brazil. Dis two matches, dey very important for di Black Stars. Ghana deY prepare to take on Portugal, South Korea and Uruguay for Group H for World Cup. Senegal play 1-1 draw wit Iran on Tuesday. Di match take place for European kontri of Austria. Na di African champions first score for di match. Own goal from Morteza Pouraliganji give Senegal di lead for di match. But di lead no last as Iran Sardar Azmoun equalise few minutes later. Dis game dey come afta di African champions bin defeat Bolivia 2-0 a few days ago. Senegal go face hosts Qatar, Ecuador and Netherlands for Group A for World Cup. Cameroon end dia international break wit a 1-0 defeat to South Korea. Dis result mean say dem lose back to back matches. England-based Son Heung-min na im score di only goal for first-half for Seoul. Coach Rigobert Song get plenty work to do for im team ahead of di finals for Qatar. Di Indomitable Lions, na di first African side to reach di World Cup quarter-finals. Cameroon go play Brazil, Serbia and Switzerland for Group G. Tunisia know say dem need to improve before dia World Cup campaign start. Di North African side chop beta beating for Brazil hand afta dem lose 5-1 for France. Di match end on a bad note afta Brazil player Richarlison suffer racist abuse. Dem throw am banana wen im bin dey celebrate Brazil second goal wey im score for Paris. Di Carthage Eagles go play France, Australia and Denmark for Group D for World Cup. Morocco manage to play goalless draw wit Paraguay. Di North African team match happun for Spain. Dis game give di new coach Walid Regragui a good chance to assess im play. Atlas Lions bin lose 2-0 to Chile a few days ago. Anoda big good news for di African team na di return of striker Hakim Ziyech afta im nine-month absence. Morocco dey Group F for World Cup wey get Croatia, Belgium and Canada. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c294kdegpjgo +sports Nigeria vs Tunisia highlights: Iwobi collect red card after Youssef Msakni goal give Tunisia victory over Nigeria Nigeria Super Eagles don crash out of di ongoing Africa Cup of Nations afta dem lose 1-0 to Tunisia on Sunday. Tunisia forward Youssef Msakni 47th minute strike na im prove to be di decisive goal as di Carthage Eagles progress to di quarter-finals. Nigeria wey win all dia group matches find di Tunisians too difficult to breakdown and dia task to draw level become hard one afta substitute Alex Iwobi collect red card. Di Everton man bin last only six minutes for pitch before im see red as im bin replace Kelechi Iheanacho. Wit much expectation before di game, di match fail to deliver on im promise as both teams struggle to create chances and those two incidents wey happun for di second half go now become di talking points of di match. Di Tunisians na dem go happy pass as na dem go play Burkina Faso for quarter-finals on Saturday, 29 January. 46mins: Taiwo Awoniyi pass di ball to signal di start of di second half. 47mins: Goal for Tunisia! Youssef Msakni long range shot beat Okoye wey try but fail to stop im shot. 50mins: If di game end like dis Nigeria go comot from di tournament while Tunisia go meet Burkina Faso for quarter-final. 53mins: Yellow Card for Laidouni. 55mins: Anoda yellow card for Tunisia, dis time na for Skhiri becos im talk sometin wey di ref no like. 59mins: Substitutions - Iheanacho OFF, Iwobi ON. Olayinka ON, Awoniyi OFF. Meanwhile Aïssa Bilal Laidouni dey ground afta Ndidi foul am. 62mins: Ndidi try im luck from 20 yards. Di shot go over di bar. 64mins: Yellow card for Iwobi aft aim foul Msakni but referee dey go check am for VAR. Referee change di yellow and im don show Iwobi Red card. Nigeria go down to 10-men. 67mins: Moses Simon collect pass inside di box, control di ball and shoot towards di left post but Bechir Ben Said rush out to make good save to stop im effort. 69mins: Substitutions - Naim Sliti come on for Hamza Rafia. 74mins: Substitute Naim Sliti don test Okoye. Di 22-year old goalkeeper parry im shot go oout for corner. 75mins: Samuel Chukwueze don come off, na Umar Sadiq replace am. 77mins: Ndidi no dey happy wit referee N'Diaye afta di ball hit am. 81mins: Good opportunity now for Nigeria as Sadiq Umar don win freekick for good position. 82mins: Moses Simon blaze di freekick over. 86mins Double substitution for Tunisia - Jaziri and Msakni OFF, Khazri and Jebali ON. 88mins: Ndidi wit anoda chance for Nigeria. Di Leicester City man drag im shot wide. 90mins: Chance for Saidq Umar! Di Almeria striker dey through on goal but im shot go narrowly wide. Di referee don add five extra minutes. 90+2mins: Umar Sadiq try to create chance as im dribble im way into di Tunisia 18-yard box but Taibi stop am from running through on goal. Full Time: Nigeria don comot from Afcon 2021 afta dem lose 1-0 to Tunisia. 1min: Tunisia don take di first kick of di game as dis round of 16 match don start. 2mins: Straight from di kickoff Nigeria win di ball and get cornerkick. Ndidi bicycle kick from di corner go over. 5mins: Tunisia try to counter quickly but Jaziri through ball no meet anybody. 8mins: Both teams dey size each other up as nobody don create any clean chance yet. 10mins: Chance! Youssef Msakni nearly give Tunisia di lead but Troost-Ekong block im goal bound effort. 12mins: Good chance for Nigeria! Simon Moses dribble Mohammed Drager come pass give Aribo wey shoot towards goal but Tunisia defender Bilel Ifa block am from troubling di goalkeeper. 14mins: Nigeria don get three corner kicks now but for those times Tunisia clear dia lines. 18mins: Nigeria don get four shots on goal so far but none don dey on target. Meanwhile Tunisia get one shot wey don dey on target. 20mins: Referee N'Diaye from Senegal don show Kelechi Iheanacho yellow card afta im foul Msakni. 24mins: Elyes Skhiri foul Wilfred Ndidi. 28mins: Nigeria goalkeeper Maduka Okoye get feel of di ball as im catch Drager cross. Okoye don be spectator for di most part of dis match as Tunisia don rarely threaten di Super Eagles. 33mins: No real opening yet so far for di match. Tunisia dey lead for possession as dem get 51%, Nigeria get 49%. 37mins: Di Tunisians dey comfortable wit Nigeria holding di ball while dem sit back dey mark di spaces. 39mins: Hamza Rafia try im luck from distance but im shot no even trouble Okoye for Nigeria goal post. 43mins: Rafia foul Ndidi for Nigeria half. Di winner of dis game go play Burkina Faso for di quarterfinal afta dem beat Gabon on penalties. 45mins: Referee N'Diaye blow im whistle for half time. Dis scoreline na Nigeria 0-0 Tunisia Nigeria line-up: 1. Okoye, 2. Aina, 22. Omeruo, 5. Troost-Ekong, 12. Sanusi, 4. Ndidi, 10. Ayodele-Aribo, 17. Chukwueze, 14. Iheanacho, 15. Simon, 19. Awoniyi. Tunisia line-up: 22. Saïd, 20. Dräger, 2. Ifa, 3. Talbi, 5. Haddadi, 25. Ben Slimane, 17. Skhiri, 28. Laidouni, 7. Msakni, 11. Jaziri, 19. Rafia. https://www.bbc.com/pidgin/60103853 +sports Police drop Neymar rape case because of no evidence "Police wey dey investigate rape accuse against Brazilian football player Neymar say dem don close di case. Sao Paulo attorney general office say dem suspend di case due to lack of evidence, but go send di case to lawyers for final decision. Dem open di investigation after Brazilian model Najila Trindade allege di footballer attack her for hotel in Paris, France for May. Neymar deny di accusations and add say di lady just one collect money from im hand. Tok-tok pesin for Neymar tell tori pipo AFP say Neymar no dey able to comment on di police decision to drop di case, for now. Na for June tori come out say one woman dey accuse Neymar say e rape am wen di Paris St-Germain star release seven minute video on Instagram say im dey face accuse of rape. Im also publish whatsapp messages and photos wey e claim say di woman send am. For inside di video, im say im decide to come out to ""prove say nothing really happun."" Trindade later go public for television interview and release video wey show she and Neymar inside. Police later file defamation suit against Trindade, she later come out accuse di force say dem dey corrupt according to news agency AFP. Prosecutors now get 15 days to evaluate di case before judge go make final ruling." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49167008 +sports Why Pogba dey leave Manchester United again "Paul Pogba go leave Manchester United on free transfer, di club don confam. E go happun wen im contract expire at di end of June. Di 29-year-old cost United a former record £89m wen e re-join di club from Juventus for 2016. E make 27 appearances for di final season wey injury worry am well-well on im second time for di club. ""Na low-key end to im United career wey bring so many individual high moments."" Na so Old Trafford club tok for statement. ""So many beautiful goals, assists and pieces of skill. ""For a boy wey join di academy at 16 to make over 200 United appearances. ""And lift di Youth Cup, along wit two major trophies na something wey deserve celebration.” Pogba first join United from French club Le Havre for 2009 as 16-year-old and for for di academy side wey win di Youth Cup for 2011. E make just seven senior appearances before im contract expire for July 2012 and e comot go join Juventus. Pogba win eight major honours for Turin, including four serie A titles back to back, before e make im record-breaking return to Old Trafford. E win di EFL Cup and Europa League during im first season for di club but dat na di only cup wey e win during im second time for di club. Di disagreement wit di former manager Jose Mourinho make am lose im position as vice-captain for 2018. Injuries and poor form reduce im impact. Pogba score 39 goals for 233 appearances for di two times wey e spend for di club. Fans boo am for im final home appearance against Norwich City for April wen e comot as substitute." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cq5w7ygrpq7o +sports Champions League: Klopp, Guardiola para for new competition format wey Uefa approve "European football join-bodi Uefa don announce new format for Champions League competition, but no be everybody happy wit di change. From 2024, one of football most popular club competition go get 36 teams for di opening stage, instead of di 32 teams wey e be currently. Di Union of European Football Association [Uefa] say dis new format na based on plenty tok-tok wey dem do wit important stakeholders for di European football community. ""Dis go give four more clubs di opportunity to compete against di best clubs for Europe,"" na so Uefa tok. On 19 April di new change collect support from di European Club Association Board and di Uefa Club Competitions Committee (wey get club representatives inside). And no be just Champions League go use dis new format, as Europa League and di new Europa Conference League go follow. Di results of each match go decide di overall ranking for di new league. After di top eight teams don advance automatically enter round of 16, teams wey dey ninth to 24th position go do play-off round for di remaining eight slots. After round 16, di competition go follow di same 'old' pattern wey everybodi sabi. Uefa say fans go get more opportunities to see di top-top teams for Europe play each oda for di early stage of di competition. Every game dey important. Di new league format mean say any result get serious impact for every team - even up to di last match day. Whether team win or lose fit make am possible for dem to qualify automatically (or not) for di last 16. Some football players and managers don reject di new format. Dem say na money make di joinbodi decide to add more clubs to di competition. Liverpool manager Jurgen Klopp bin hala say: ""Uefa no ask us, di Super League no ask us. Always dia own na make we play more games. Di new Champions League, wetin be di reason for that? Money... I no know how we suppose manage wit even more games"". E no epp Uefa say dem announce di new format, days after di drama wey surround di new European Super League (ESL) comot full everywia. Fans bin accuse ESL organisers say na big money wey dem dey find no gree dem see say dia league no benefit di bigger football community. Meanwhile, od pipo complain say more matches mean say players go dey more affected. Manchester City midfielder Ilkay Gundogan say di new Champions League format na di ""lesser of two evils"" if pesin compare am to ESL. Say in all of dis nobody dey put players health for mind. And im oga Pep Guardiola belief say more matches go increase risk of injury to di players. ""We need to ask Uefa and Fifa to extend di year, maybe we go get 400 days a year. Whether dat one go be di solution."" Uefa and Fifa never react to dis complaints." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56893055 +sports ROC Olympics: Reason why Russia dey banned from Olympics, even though dia athletes dey compete for di Tokyo games "ROC dey among di top five teams wey dey currently top di medals table for di 2020 Tokyo games. So far, dem don win 12 medals for di Olympics wey include four gold, five silver and three bronze. ROC stand for Russian Olympic Committee. Tori be say di sportsmen and women for ROC dey unable to play under di flag of their kontri, because of dia kontri history of some kain mago-mago tins wey dem don do for sports before. For 2019, Russia chop ban from global sporting events from di World Anti-Doping Agency (WADA) ontop accuse of cover-up and drug cheating. E mean say, Russian athletes no dey allowed to represent Russia while dem dey competing for di Games. ROC no be Kontri, but na loophole wey Russian athletes use to compete for di Olympics, even though Russia dey banned. ROC stands for Russian Olympic Committee, and Russian athletes dey allowed to represent di committee, even though dem no fit represent dia own country. Olympic rules require make dem use di acronym ROC instead of di full name. Dis one mean say, wen a Russian Olympian win gold, dem no go fly di Russian flag, and di Russian national anthem no go play. Instead, na snippet of Tchaikovsky piece dem go play as dem raise di ROC flag. Team uniforms dey allowed to use di word ""Russian"" but only if e use di phrase ""neutral athlete"", wey go make an clear say di person no dey represent Russia. Russia chop ban from competing for several major international events by WADA for late 2019. Di decision come afta one investigation find out say Russian authorities bin plant fake evidence and deleted files linked to positive doping tests wey for help to identify drug cheats. Di revelations bin point to one state-sponsored doping program for Russia. Russia bin don blame technical issues for dia doping data before. Wen WADA sama di ban on Russia for 2019, e bin suppose be for 4 years, but, dem reduce am to 2 years on appeal. Di ban bin come into effect from di end of di appeal process, for December 2020. Dat one mean say no be only Olympics di kontri go miss out on, dem go also miss out on di 2022 Winter Olympics and di 2022 Football World Cup. No. Oda teams wey technically no dey represent any country include Chinese Taipei, wey get athletes from Taiwan, and di Refugee Olympic Team, dia name explain who dem be. Some external territories include di UK Virgin Islands, di US Virgin Islands and Guam wey also dey compete as separate teams." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57976483 +sports Champions League draw: Uefa draw see Manchester City land inside same group wit PSG Premier League champions Manchester City don find demsef inside di same group wit French club Paris St Germain. Dis na result of di draw wey Uefa do on 26 August for teams to know who dem go follow play for di group stage of Champions League. Earlier for di show, dem award Ngolo Kante of Chelsea as di Midfielder of di Season 2020/21, while Edouard Mendy of same club win for Goalkeeper. Borussia Dortmund wunderkind Erling Haaland win Forward of di Season. Di Norwegian na only 21 years old. Di big individual award go to Jorginho wey win Uefa Men's Player of di Year for di 2020/21 season. See how di groups stand. Group A Group B Group C Group D Group E Group F Group G Group H https://www.bbc.com/pidgin/sport-58348031 +sports Commonwealth Games: Birmingham 2022 fotos of all di 12 women wey win gold medals for Nigeria "Monday 8 August na di final day of action for di 22nd Commonwealth Games wey dey take place for Birmingham, United Kingdom and Nigeria don win 12 gold medals so far. Na di kontri female athletes na dem win all di gold medal to di admiration of dia kontri pipo. Di kontri Minister of Youth and Sports Development, Sunday Dare praise di athletes for dia 'breath-taking command performance.' Female athletes also don help Nigeria win 6 silver and 8 bronze for di 2022 Commonwealth Games. While di male athlete don help win 3 silver and 6 bronze for di kontri. In total female don win 26 medals for Nigeria while male win 9 medals So far, Nigeria don win total of 35 medals for now and dey number 7 rank for di Birmingham 2022 medal table. 1. Adijat Adenike Olarinoye Adijat Adenike Olarinoye be di first athlete to win Nigeria first gold medal for di 2022 Commonwealth Games for Birmingham. Olarinoye wey be 23 years old lift a total of 203kg to win gold for di women 55kg - Final on Saturday 30 July 2022. She bin lift 92kg for di snatch, 111kg for clean and jerk, and lift 203kg in total. 2. Rafiatu Folashade Lawal Rafiatu Folashade Lawal give Nigeria di second gold medal for di 2022 Commonwealth Games for Birmingham Lawal wey be 25 years old lift 206kg to clinch di gold for di Women's 59kg - Final on Sunday, 31 July, 2022. 3. Chioma Onyekwere Chioma Onyekwere make her make history as di first Nigerian to win di women Discus Throw gold medal for di Commonwealth Games on Final Tuesday 2 August 2022. For her first appearance for di games she throw her season best of 61.70m for her fourth attempt to snatch di lead from Jade Lally of Britain. Chioma Onyekwere wey also be di African Games and African Athletics champion na 28-year-old. Di USA based engineer become only di second African female for di Games history to win gold afta Elizna Naude of South Africa do am for 2006 Melbourne games. 4. Goodness Chiemerie Nwachukwu Goodness Chiemerie Nwachukwu win gold medal for di Women's Discus Throw F42-44/61-64 - Final on Thursday 4 August 2022. Di 23 years old throw 36.56m to to clinch di gold medal for Nigeria. 5. Alice Folashade Oluwafemiayo Alice Folashade Oluwafemiayo win gold for Team Nigeria for di Women's Heavyweight - Final on Thursday 4 August, 2022. Di 37 years old Paralympic champion set a new Commonwealth Games record and smash di women's -86kg world record to win di medal. 6. Blessing Oborududu Blessing Oborududu no disappoint Nigeria as she win for di Women's Freestyle 68 kg - Gold Medal for di Commonwealth games on Friday, 5 August, 2022. Oborududu wey be 33 years old retain di title wey she win four years ago for Gold Coast. Wrestler Oborududu defeat Linda Morais for di 68kg women category final. 7. Odunayo Folasade Adekuoroye Odunayo Folasade Adekuoroye add to di number of gold wey Nigeria don get as she win for di Women's Freestyle 57 kg - Gold Medal for di Commonwealth games on Friday, 5 August 2022. Adekuoroye wey be 28 years old defeat her Indian opponent Anshu Malik for di 57kg freestyle category. Dis na Adekuoroye third Commonwealth Games tile She be two-time reigning Commonwealth Games champion and di reigning African champion. 8. Miesinnei Mercy Genesis Miesinnei Mercy Genesis from Nigeria take di Women's Freestyle 50 kg - Gold Medal for di Commonwealth Games on Saturday 6 August 2022. Genesis wey be 24 years old defeat Canada wrestler, Parks Madison to win di medal. She win di encounter for di Coventry Arena on Saturday evening. 9. Eucharia Njideka Iyazi Eucharia Njideka Iyazi get gold medal for di Women's F55-57 Shot Put - Final for Birmingham on Sat, 6 August 2022 Di 48 years old win with throw of 10.03m. 10. Tobi Amusan Tobi Amusan wey be World hurdles champion win gold for di Women's 100m Hurdles - Final Sunday, 7 August, 2022 Amusan wey be 25 years old clock time of 12.30s for di final for Alexander Stadium to successfully defend her Commonwealth Games title on Sunday. 11. Tobi, Favour, Rosemary and Nzubechi4 x 100m Relay Four Nigerian female athlete, Tobi Amusan, Favour Ofili, Rosemary Chukwuma and Nzubechi Grace Nwokocha help di kontri win gold for di Women's 4 x 100m Relay - Final on Sunday, 7 August, 2022. Amusan start di race with brilliant first leg, before handing ova to Ofili, wey make sure say Nigeria maintain di advantage, before giving Chukwuma di baton. Chukwuma come hand ova di baton to di reigning Nigerian 100m queen, Nwokocha. Nwokocha maintain di first position advantage upon di threat of Great Britain's anchor leg Darly Neita to bring home Nigeria first women relay gold. Grace Nwokocha tell BBC say di team bin dey disappointed for not winning medal for di world athletics championships for Orgeon and di win for Birmingham na relief. ""E dey good to come up here, executing our race and getting di best out of am. And dis na wetin wey always plan for. And we dey happy with wetin we get today,"" ""We all dey work togeda, e no mata our ages, and we just want to work togeda, get di best out of oursef,"" Nwokocha tok. 12. Ese Brume Ese Brume break Commonwealth Games record for Long Jump to win Gold for Nigeria. Brume wey be 26 years old win Women's Long Jump - Final on Sunday, 7 August 202 to reclaim her commonwealth games title for di long jump with record of 7 meters. She tell BBC say; ""dis na one thing I really want. I dey like, I want to get di game record and I go push hard for am. And I keep on praying and believing. "" Nigeria Minister of Youth and Sports Development, Sunday Dare thank Ese Brume for making di kontri proud. While di Governor for di state where Ese Brume come from, praise her for making history and making Nigeria proud. Ifeanyi Okowa write for im twitter say; ""A great leap into di history books for our daughter, Ese Brume, wey just break di Commonwealth Games long jump record. Dis na fantastic day for Nigerian sports as a whole!"" Oda Nigerians both female and male also don win silver and Bronze for di Birmingham 2022 Commonwealth Games." https://www.bbc.com/pidgin/sport-62462780 +sports "UFC259 [Who won between Israel and Jan?]: Jan Blachowicz beat ""Israel Adesanya"" for latest UFC fight" "Light heavyweight title-holder, Jan Blachowicz (28-7) don beat undefeated middleweight Israel Adesanya(20-1) to remain as di light heavyweight champion for di UFC 259 for Las Vegas. Jan Blachowicz of Poland win Israel Adesanya afta judges hand over di scores of 49-46, 49-45 and 49-45 in favor of di Polish champion. Dis go be Isreal first career loss. Afta di game, di Nigeria-born New Zealand-based Mixed Martial Artist say di game no go as im expect but e dey okay. Since Jan Blachowicz start im UFC run with a 2-4 record, di Polish Mixed Martial Artist don win nine of im last 10 fights, e come become undisputed UFC light heavyweight champion. Na Blachowicz give Israel Adesanya im first defeat. Di dream of Nigeria-born New Zealand-based Mixed Martial Artist to become two division champion don scata as Jan Blachowicz beat am to retain di light heavyweight champion title for di UFC 259 for di UFC Apex for Las Vegas. Blachowicz for di first two rounds bin dey take am easy wit Adesanya but for di final two rounds, e turn di table as e score 49-45, 49-45 and 49-46 for di judges to declare am winner. Adesanya bin start di fight on high note as e pounce on im opponent for di first and second round but for di 4th and final rounds, di Polish take control of di fight as e take down Adesanya. Blachowicz end di fight in full mount as e rain down punches on Adesanya, wey neva lose before for im mixed martial arts career wey start for 2012. Adesanya, di energetic Nigerian-born New Zealander, don fail to join Amanda Nunes, Conor McGregor, Daniel Cormier and Henry Cejudo as UFC two-belt champions title holders. Adesanya na di sharper, more aggressive striker for di early rounds, but Blachowicz survive di attack for di beginning before e launch im game plan. Blachowicz dey celebrate im latest victory for a fighter wey win im title last for September afta six years wey e don dey UFC and 13 years as a professional. Just before dis fight im lose, Israel ""Di Last Stylebender"" Adesanya. say: ""For me na about di victories. Di names you collect, di scalps wey you take along di way. I wan be di guy wey take out everyone so that wen dem don tok finish dem go be like, 'na im be di greatest of all time.' Di Nigeria-born New Zealand-based fighter bin dey tok ahead of e ogbonge fight against fearsome light heavyweight champion Jan Blachowicz, 38, wey be di headline fight of UFC 259 on 6 March." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56310871 +sports Kashimawo Laloko death: NFF former technical director Kashimawo Laloko don die Kashimawo Laloko, Nigeria Football Federation [NFF] Former technical director don die. Oga Laloko wey be di Olori Parakoyi of Egbaland, die afta brief illness for Sacred Heart Catholic Hospital, Abeokuta at di age of 76 years. According to im family, dem go bury am for Abeokuta on Monday March 29. Di sport world go remember Oga Laloko for di contribution wey im make for sports, especially for di Pepsi Academy wey develop many football talents like Mikel Obi, Joseph Akpala, Elderson Echejile, Yinka Adedeji plus odas, since e begin for November 1992. Im bin also work as national team coach for Gambia. Oga Laloko bin be former old boy of di popular Abeokuta Grammar School for Ogun state. https://www.bbc.com/pidgin/media-56564447 +sports Spectator injure player, referee for pitch invasion wey make dem abandon game "Dem abandon one A-League Melbourne afta one spectator injure player and di referee during obe pitch invasion. Fans run to di pitch for di 22nd minute of di match between Melbourne City and Melbourne Victory. Referee Alex King bin dey try to shield City goalkeeper Tom Glover wen both of dem suffer cuts to dia faces afta pesin hit dem wit metal bucket. Dem don give Glover plenti stitches before dem cari am go hospital for scans. One City statement say Glover, 24, bin go for ""further follow up checks"" afta di club doctor access am. One TV cameraman also injure by a flare. For one statement, Victory tok say di club dey ""devastated"" and ""also condemn"" di ""appalling behaviour"" of fans for Saturday game for AAMI Park, wey di two clubs share. ""Di action wey occur, wey see spectators enta di pitch and injure one Melbourne City FC player, one official and a Network 10 cameraman, no dey acceptable under any circumstance and get no place in football,"" e continue. Supporters bin dey protest before and during di game, wey make dem initially suspend then later abandon di game on player safety grounds. Di Australian Professional Leagues (APL) announce last week say e don sell di A-League Grand Final rights to Sydney for di next three years, and sake of dat dem plan protest for several A-League games dis weekend. Fans of both Victory and City plan a walk-out on di 20-minute mark but di protest escalate afta suporters begin throw flares on to di pitch. City bin dey lead 1-0 wen Glover appear to throw one flare back towards di crowd, according to Melbourne newspaper The Age. Victoria Police say about 150-200 Victory fans later run enta di pitch, and dem hit Glover and referee King wit bucket wey dem use dispose flares, cover both of dem wit powder and smoke. Diem quickly comot di players, including former Portugal and Manchester United winger Nani, from di field and Football Australia say dem call off di game ""to protect di integrity of di match"". One Football Australia statement say dem go hand down ""strong sanctions"" afta di ""shocking scenes"". ""Dat kain behaviour no get place for Australian football, wit a full Football Australia investigation to commence immediately,"" e add. One APL statement say: ""Di Australian Professional League dey co-ordinate wit Football Australia sake of dis events.""" https://www.bbc.com/pidgin/articles/c72100keevxo +sports Qatar World Cup 2022: Wetin African teams need to progress to knockout stage With one or two games left to de end of de Group stage at de Qatar 2022 World Cup tournament, de big question be what be de chances of African teams?\n\nFive countries dey rep Africa in de tournament, Ghana, Cameroon, Morocco, Senegal den Tunisia. Only de top two teams for each group go qualify for de round of 16.\n\nSome of dis teams dey need win, draw or by goal advantage if two teams get de same points. Dis piece go explore what Africa teams for do to qualify for de Round of 16. Ghana go fit enter de round of 16 if dem beat Uruguay for dem final group fixture, despite result of other games. \n\nDem go move to de top of de group if dem win against Uruguay and Portugal lose to South Korea by a wide goal margin. \n\nIf dem win and Portugal lose by only a one-goal difference, Ghana go fit finish first if dem score more goals against Uruguay. De Black Stars go fit also qualify if dem draw wit Uruguay and Portugal defeat South Korea. Dis go leave de West Africans wit four points from de group. If Portugal draw wit South Korea and Ghana play draw wit Uruguay, de Black Stars go still finish second behind Portugal wit four points. Ghana go comot from de tournament if dem lose to Uruguay ni matter wetin Portugal and South Korea play for de other game. Cameroon for win dia last match and hope say de other games go in dia favour. \n\nSimilar to Tunisia, Cameroon need a victory against five-time World Cup winners Brazil to progress.\n\nBrazil already don qualify for de last 16 but for Cameroon, dem go hope say de outcome of Serbia-Switzerland game go give dem lifeline for de round of 16. Cameroon must win Brazil by a solid goal margin to finish wit four points and hope Serbia defeat Switzerland. If Serbia and Switzerland play draw, Cameroon need to defeat Brazil by more dan one goal to improve dia goal difference wey currently stand at -1. Morocco need one point to qualify to de next stage.\n\nA draw in dia final match against Canada on Thursday go give dem de needed qualification. \n\nMorocco go fit win de group if dem win and Belgium beat Croatia. But de Atlas Lions go fail to qualify if dem lose to Canada and Belgium also defeat Croatia by less dan one goal margin. If e happun like dat, both Morocco and Croatia go finish on de same four points but de 2018 World Cup finalists get better goal scored record dan di North Africans. Three points for dia last game fit no go be enough for Tunisia who dey bottom of dia group if de North Africans beat defending champions France, who already don qualify for de round of 16.\n\nTunisia go fit progress on goal difference if dem win France by any margin and den Australia-Denmark ends in a draw.\n\nBut a win for Denmark go reduce dia chances down to goal difference, goals scored or even, possibly, de fair play record. A draw against France no go dey enough as dem go finish de group wit just two points from three matches. Senegal need either win or draw to qualify for de next round.\n\nCurrently at 3 points, if dem secure win against Ecuador dis go give dem 6 points on de group table. \n\nSenegal go fit go through with draw only if Netherlands lose to Qatar by margin of three or more goals. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c25x7w4geeyo +sports Wetin fit be Ronaldo fate for Man Utd afta im Interview "Manchester United say dem dey take ""appropriate steps"" afta Cristiano Ronaldo interview. For di Interview im say ""di club betray am"". Di Portuguese player also say im ""no get respect"" for manager Erik ten Hag and dem dey force am out of Old Trafford. Manchester United tok dis morning say dem dey take right steps in response to Cristiano Ronaldo recent media interview."" Di club say dem no go tok anything for now until ""dem finish di process "". Afta dis interview wit Piers Morgan for TalkTV, Ronaldo future for Man Utd don get K- leg. Ronaldo wey be 37 years go captain Portugal for World Cup for Qatar, dia opening Group H game na against Ghana on Thursday. Im neva play ball since im captain United for dia 3-1 defeat to Aston Villa on 6 November sake of sickness Ten Hag bin drop Ronaldo for dia Premier League game for Chelsea afta im refuse to come on as a substitute against Tottenham three days earlier. Di Red Devils, wey beat Fulham 2-1 on Sunday, dey fifth for Premier League for Ten Hag first season as manager. Manchester United want see di full extent of Cristiano Ronaldo interview. Now dem don tok. Di club no want tok exactly wetin dem mean by 'appropriate steps' but to cancel Ronaldo contract and/or take legal action dey likely high for dia list. United dey solidly behind manager Erik ten Hag, im name full for Ronaldo mouth. One Ronaldo claim na say Ten Hag bin only want bring am on for di final minutes of last month win over Tottenham to prove a point. Ronaldo add say im no get respect for di Dutchman. Di club also praise di club and dia staff, wey Ronaldo claim say dem still dey tins di old way. E dey vey unlikely say Ronaldo go play for United again under Ten Hag, so di only way now na to leave. But e no dey straightforward like dat. Ronaldo na Premier League highest-paid player and im contract go get plenty conditions. Di club, don knack hand for chest say dem go sharpery address dis matter. Dem no go want make di matter drag for too long. Highlights of Ronaldo controversial interview: Dis na quick guide to wetin pipo tok and who tok am:" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp3yxejvnnvo +sports ‘Ronaldo penalty be gift, VAR sleep, dem disappoint we’, Ghana coach react after loss to Portugal Ghana national team coach, Otto Addo call out referee Ismail Elfath say he “gift” Cristiano Ronaldo penalty in dia game against de Portuguese side. Ghana manage hold Portugal from finding de net until de referee rule clearance from defender, Mohammed Salisu as foul against Ronaldo, resulting in penalty. De Ghanaian defender and other players after the clearance talk de referee to check VAR to confirm say he no commit foul against Ronaldo but referee Ismail Elfath refuse to check VAR. “We dey very disappointed, especially when I see de penalty situation. Up to that point we get good match” Ghana national team coach Otto Addo talk after de game. “I think say e be wrong decision, we dey play de ball... I no know why VAR no come up, no explanation dey. Dis be difficult against world class team when dem dey lead we” he add. According to him “if somebody score goal then congrats, but dis be gift... special gift from de referee.” Some football pundits den fans dey call for Fifa to suspend de referee, Ismail Elfath over poor officiating. Dem feel say en handling of de game no dey on professional level based on some of de calls he make. Other football fans also lament unfairness in de game when African countries dey play. Ghana manage neutralize de Portuguese side until Ronaldo convert penalty into first goal.\nAs de game progress, Ghana captain score from open play to draw de game at 1 - 1.\nBut after Coach Otto Addo remove Dede Ayew and Kudus Mohammed from de game, de Black Stars within minutes lose dia compact gameplay wey result in second goal for Portugal. Third goal from Portugal almost crush de Black Stars amidst calls for de referee to check VAR for possible offside but no VAR check happen. De Ghanaian side manage draw out second goal after Osman Bukari score header in de 89th minute bringing de scoreline to 3 - 2. With nine minutes added time, de Black Stars try steal ball to level but forward Inaki Williams no fit convert de last effort as he fall ground in de penalty box. De referee blow en whistle to bring de game to an end with Portugal securing all three points. Portugal go top of de Group H table with three points as Ghana remain for bottom. South Korea and Uruguay dey second and third on de table after dem play goalless draw. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c515p7w8wyjo +sports Chelsea vs Real Madrid highlight: Karim Benzema hat-trick put Real ahead of Blues for Champions League quarter-final Di Los Blancos dey town and dem don show say dem no go carry last for di Champions League. For di first leg of di Champions League quarter-final, Real Madrid face Chelsea and dem no hold back wit scoreline of 3-1. Karim Benzema hat-trick sweet fans and give Real Madrid di needed gap for di game wey shele for Stamford Bridge. Dis one don push di team closer to di semi-final. Before now, early predictions bin put Chelsea as favourites to win di game based on say di Blues win dia previous match. Kai Havertz bin score for di Blues, but dem bin waste di game, sotay substitute Romelu Lukaku miss one beta chance. Many eyes bin dey di Tuchel-led Chelsea team to deliver especially as dem dey play for home but as e be so, dat dream fit take corner seat if dem no secure victory for di second leg wey go take place for Santiago Bernebeu on Tuesday, 12 April. Meanwhile Carlo Ancelotti, di Real Madrid coach for miss chance to dey field wit im players afta e no follow dem go London on Tuesday in preparation for di game, but di coach get di all clear to join im team afta e test negative for Covid-19. Di Spanish side no waste time to show say na dem come play football today wit dia 1 - 0 victory over Germna side Munich. Dis win don end Bayern record-breaking away run for di Champions League since 2017. Na Arnaut Danjuma score as Unai Emery side secure dia position to potentially dey for di semi-final and now all eyes go dey on di return game. Dis go be di Dutchman sixth Champions League goal for di Yellow Submarines. Bayern go need do magic against di Spanish side on Tuesday, 12 April wen di teams meet for di second leg of di quarter final. https://www.bbc.com/pidgin/sport-61018655 +sports Peng Shuai: Chinese tennis star deny say she make sexual assault claim as pipo para about am "Chinese tennis star Peng Shuai don deny say she make sexual assault accuse against anybody, dis na afta tori comot say she accuse one Chinese leader force her to sleep wit am. Di tori of di allegation begin trend afta di player disappear afta she make post of di accusation online. For fresh interview di star say plenti pipo misunderstand di post wey she make. Women Tennis Association - WTA say dem still dey concerned say di state dey control her comments. For interview wit one Chinese Language newspaper, Miss Peng explain say ""I no write or say any pesin sexually assault me, e go good to emphasize dat clearly"". For di original note wey dem post for Chinese social media platform Weibo for November, she accuse former vice premier Zhang Gaoli say e force her to have sex wit am. She tell tori pesin Lianhe Zaobao say nobody dey monitor her, ""why pesin go dey monitor me, I always dey free"". Dis interview happun for one sporting event for Shanghai wia she appear wit oda national athletes including basketball player Yao Ming. For dia response WTA say dem welcome say she don appear for public but add say dat one no clear dia concern about her well being and ability to communicate on her own. ""We stil dey call for full fair, and transparent investigation into her allegation of sexual assault, dat na main reason why we chook mouth for di mata"" na so WTA tok. For November 2, Peng post 1600 words note for Weibo. Dat post kick off major case for di #MeToo movement for China. She address di post to Mr Zhang claim say dem bin get romantic relationship and di man coerce am to have sex. She ask ""Why you go come back to find me, take me to your home and force me to have sex wit you?"". Dem later delete di post for Weibo, but by den di post don go viral. Na afta di post Peng disappear wey make plenti pipo begin fear for her safety. #WhereisPenShuai begin dey trend. Top stars including Naomi Osaka, Serena Williams and Novak Djokovic join di trend. Plenti groups and organisations begin chook mouth into di mata including Chinese media organisations, International Olympics Committee IOC, WTA etc. WTA suspend all dia tournaments in China sake of dis mata, dem dey put pressure on di IOC and oda sporting groups to take similar action but IOC no gree. Di player bin don tell IOC twice for video call say she dey ok, but plenti pipo feel say she dey under duress and pesin dey control her comments." https://www.bbc.com/pidgin/sport-59726645 +sports Uefa Champions League matchday two fixtures, time, team news Liverpool go host Ajax for dia second group match of di Uefa Champions League for Anfield dis week. Tuesday and Wednesday go see a total of 16 games for Europe biggest club competition. Di Reds bin lose dia opening group A match 4-1 to Italian side Napoli. Dis na di fixtures for Match Day two. Check out all di team news for Tuesday and Wednesday matches from Uefa. Group A: Liverpool vs Ajax - 8pm Group B: Porto vs Club Brugge - 8pm Leverkusen vs Atlético- 8pm Group C: Plzeň vs Inter- 5:45pm Bayern vs Barcelona- 8pm Group D: Sporting CP vs Tottenham- 5:45pm, Marseille vs Frankfurt- 8pm Liverpool possible starting line-up: Alisson; Alexander-Arnold, Matip, Van Dijk, Robertson; Elliott, Fabinho, Thiago Alcántara; Salah, Núñez, Luis Díaz Injury: Konaté, Henderson, Jones, Ramsay, Keïta, Oxlade-Chamberlain and Robertson Ajax possible starting line-up: Pasveer; Rensch, Timber, Bassey, Blind; Berghuis, Álvarez, Taylor; Tadić, Kudus, Bergwijn Injury: Di Dutch club no get any injury palava for dia squad. Ajax and Napoli get three points each while Liverpool and Rangers get zero points. Plzeň possible starting line up: Staněk; Havel, Hejda, Pernica, Jemelka; Kalvach, Bucha; Sýkora, Vikanova, Mosquera; Chorý Injured players: Kopic and Kliment Sporting CP possible starting line-up: Adán; Inácio, Coates, Reis; Pedro Porro, Ugarte, Morita, Nuno Santos; Pedro Gonçalves, Edwards, Francisco Trincão Injured players: Jovane Cabral, Luís Neto, St. Juste Tottenham possible starting line-up: Lloris; Emerson, Dier, Romero, Lenglet, Perišić; Højbjerg, Bentancur; Richarlison, Kane, Son Injured players: Lucas Moura Porto possible starting line-up: Diogo Costa; Zaidu, David Carmo, Pepe, João Mário; Uribe, Eustáquio, Galeno, Pepê; Toni Martínez, Evanilson Injured players: Taremi and Otávio Club Brugge possible starting line-up: Mignolet; Mechele, Sylla, Meijer; Skov Olsen, Nielsen, Odoi, Vanaken, Onyedika; Jutglà, Yaremchuk Injured players: Buchanan, Lang, Rits, Mata Leverkusen possible starting line-up: Hradecky; Kossounou, Tah, Hincapie, Bakker; Aránguiz, Andrich; Frimpong, Diaby, Hudson-Odoi; Schick Injured players: Wirtz, Bellarabi, Adli Lunev, Palacios Atlético possible starting line-up: Grbić; Hermoso, Witsel, Reinildo; Molina, Marcos Llorente, Koke, De Paul, Carrasco; João Félix, Morata\nInjured players: Savić, Reguilón, Giménez Bayern possible line-up: Neuer; Pavard, Upamecano, Hernández, Davies; Kimmich, Sabitzer; Sané, Musiala; Müller, Mané Injured players: Coman and Sarr Barcelona possible line-up : Ter Stegen; Koundé, Araújo, Eric García, Marcos Alonso; Gavi, Busquets, Pedri; Dembélé, Lewandowski, Raphinha Injured players: None Marseille possible line-up: Pau López; Bailly, Gigot, Kolašinac; Clauss, Rongier, Gerson, Nuno Tavares; Cengiz Ünder, Alexis Sánchez, Payet Injured player: Mbemba (suspended) Frankfurt possible line-up: Trapp; Knauff, Tuta, N'Dicka, Pellegrini; Sow, Dina Ebimbe; Lindstrøm, Götze, Kamada, Kolo Muani Injured players: Touré, Buta, Lenz, Rode, Onguéné Milan possible line-up: Maignan; Calabria, Kalulu, Tomori, Hernández; Tonali, Bennacer; Saelemaekers, De Ketelaere, Rafael Leão; Giroud Injured players: Rebić, Origi and  Krunić Dinamo Zagreb possible line-up: Livaković; Moharrami, Ristovski, J. Šutalo, Perić, Ljubičić; Ademi, Ivanušec, Mišić; Oršić, Petković Injured players: B. Šutalo Shakhtar possible line-up: Trubin; Taylor, Bondar, Matviyenko, Konoplia; Shved, Bondarenko, Stepanenko, Sudakov, Mudryk; Zubkov Injured players: None Celtic possible line-up: Hart; Juranović, Carter-Vickers, Jenz, Taylor; O'Riley, McGregor, Hatate; Abada, Furuhashi, Jota Injured players: None Rangers possible line-up: McLaughlin; King, Goldson, Sands, Barisić; Davis, Lundstram; Arfield, Kamara, Kent; Čolak Injured players: Lawrence, Souttar, Helander and Hagi Napoli possible line-up:  Meret; Di Lorenzo, Rrahmani, Kim, Mário Rui; Zambo Anguissa, Lobotka, Zieliński; Lozano, Simeone, Kvaratskhelia Injured players: Victor Osimhen Chelsea possible line-up: Arrizabalaga; Fofana, Thiago Silva, Koulibaly; James, Jorginho, Kovačić, Cucurella; Mount, Sterling, Havertz Injured players: Kanté Salzburg possible line-up: Köhn; Dedić, Pavlović, Bernardo, Ulmer; Seiwald; Capaldo, Kameri, Kjærgaard; Okafor, Fernando Injured players: Diambou, Koïta, Omoregie, Piątkowski, Tijani, Solet and Wöber Real Madrid possible line-up: Courtois; Carvajal, Rüdiger, Alaba, Mendy; Modrić, Tchouameni, Camavinga; Valverde, Rodrygo, Vinícius Júnior Injured players: Éder Militão, Benzema and Lucas Vázquez Leipzig possible line-up: Gulácsi; Simakan, Gvardiol, Orbán, Raum; Laimer, Schlager; Nkunku, Forsberg, Szoboszlai; Werner Injured players: Olmo and Klostermann Man City possibly line- up: Ederson; João Cancelo, Akanji, Rúben Dias, Sergio Gómez; De Bruyne, Rodri, Gündoğan; Bernardo Silva, Haaland, Foden Injured players: Laporte Dortmund possibly line- up: Meyer; Meunier, Süle, Schlotterbeck, Guerreiro; Salih Özcan, Bellingham; Brandt, Reus, Reyna; Modeste Injured players: Bynoe-Gittens, Dahoud, Hazard, Kobel, Malen and Morey Copenhagen possible line-up: Ryan; Diks, Vavro, Khocholava, Kristiansen; Falk, Zeca, Lerager; Claesson, Cornelius, Daramy Injured players: Grabara and Amoo Sevilla possible line-up: Bounou; Carmona, Gudelj, Nianzou, Acuña; Fernando, Delaney; Lamela, Papu Gómez, Óliver Torres; En-Nesyri Injured players: Marcão and Corona Juventus possibly line- up: Perin; Danilo, Bonucci, Bremer, Alex Sandro; McKennie, Paredes, Rabiot; Cuadrado, Vlahović, Kostić Injured players: Pogba, Kaio Jorge and Chiesa Benfica possibly line- up: Vlachodimos; Gilberto, Otamendi, António Silva, Grimaldo; Florentino, Fernández; Neres, Rafa Silva, João Mário; Gonçalo Ramos Injured players: Lucas Veríssimo, João Victor and Morato Maccabi Haifa possible starting line-up: Cohen; Sundgren, Batubinsika, Seck, Goldberg, Cornud; Mohamed, Lavi, Chery; Pierrot, David Injured players: Jaber and Podgoreanu Paris possible starting line-up: Donnarumma; Ramos, Marquinhos, Mukiele; Hakimi, Verratti, Vitinha, Nuno Mendes; Messi, Mbappé, Neymar Injured players: Kimpembe https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw0ne22kll0o +sports Novak Djokovic: Di Serbian tennis player, Viktor Troicki plus odas don test positive for Covid-19 "World number one Novak Djokovic don become di latest player to test positive for Covid-19. Dis dey come afta Grigor Dimitrov, Borna Coric and Viktor Troicki wey show Coronavirus symptoms reveal say dem get di Covid-19 virus afta dem play for Djokovic Adria Tour competition. Djokovic wey be 33 years play fellow Serb Troicki for di first event for Belgrade. Great Britain Andy Murray say di positive test na ""lesson for us"", while Australia tennis player Nick Kyrgios say pipo say those wey go play for di competition make ""strong head decision"". No ATP tour event don hold since February becos of di global pandemic and di Adria Tour, wey no be ATP event na one of di first competitions to happun since then. 4,000 fans bin attend di first leg for Serbia, later pictures comot of how players bin dey dance close together inside nightclub for Belgrade. Bulgaria's Dimitrov play Croatia Coric on Saturday for di second leg for Zedar, Croatia. Becos Crotaia don lift lockdown measures, players bin dey free to no observe social distancing rules and dem bin dey hug each other for di end of dia matches. Zverev, Cilic and Andrey Rublev wey also play for di event don test negative but suggest say dem go now self-isolate for up to 14 days." https://www.bbc.com/pidgin/sport-53153759 +sports Rowan Baxter: How ex-rugby player, im wife and children die inside car fire "One former rugby league player, im wife and dia three children die inside fire for di Australian city of Brisbane. Emergency workers find di bodi of Rowan Baxter and im pikin dem, wey dey under age of 10, inside car, police tok. Hannah Baxter, wey be 31 years, die later for hospital from serious burns all ova her bodi. Report bin say she jump comot from car dey shout : ""E pour me petrol"". ""Dis na horrific scene,"" Det Insp Mark Thompson tel tori pipo: ""We still dey investigate di mata, but wen police reach di crime scene di car dey burn. Police find Rowan Baxter, 42, and im three pikin - age three, four and six - wey don die inside di car. Rowan Baxter bin dey for di front passenger seat and Hannah Baxter bin dey drive di car, police tok. Pipo wey dey live for di area tell Australian tori pipo say dem see madam Baxter, 31, jump comot from di car wen she dey on fire. She bin dey critical condition wen dem cari her go Royal Brisbane and Women's Hospital, police tok. But dem confam am say she later die on Wednesday. Tori be say di couple bin don separate late last year, and dem dey try to agree on who dia children go dey live with. pair had reportedly separated late last year, and were trying to work out custody arrangements. Prime Minister Scott Morrison say im ""heart dey go out to di families and community wey dey go through dis tragic time and di emergency workers wey dey di horrible scene."" Federal MP Terri Butler say di mata shake am well-well reach bone." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51563655 +sports Big footballers for Europe wey dey free for transfers market "Some big footballers for Europe still neva get new club even though dem don announce say dem no go renew dia contract wit dia current side afta e expire. Paul Pogba go return to Juventus? Wetin life afta Real Madrid dey like for Gareth Bale? And where Christian Eriksen dey go next? BBC torchlight some big names wey dey prepare to find new employers for di new season, as at June 21, 2022. Current club: Real Madrid Who e dey linked wit: DC United, Cardiff City, Newcastle United, Nottingham Forest, AC Milan, Tottenham Hotspur Gareth Bale departure from Real Madrid dey come afta nine years and wia im win many trophies for di Spanish capital, e win five Champions League titles and La Liga three times. Di Wales forward, wey be 32 years, bin join di Spanish champions for September 2013 for a world record fee then of ova £80m. Im don already tok say im family and fitness for di World Cup go be im main priorities wen im decide wia im go play next season. Current club: Manchester United Who e dey linked wit: Juventus, Real Madrid, Paris St-Germain, Manchester City. Paul Pogba go leave Manchester United dis summer afta six years for im second spell for di club. Di midfielder win EFL Cup and Europa League within a year of im return to United for a world record transfer fee of £89m from Juventus for 2016. While di 29-year-old help France win di World Cup for 2018, na small flashes of im fine passing range and powerful forward running im show for United, instead e turn defensive liability and annoy supporters wit many pipo bin dey complain say na lack of effort. For one documentary wey cover Pogba private life e claim say improved United £300,00 per-week na ""nothing"" e suggest say whoever sign am go need to hold im side well-well. Current club: Brentford Who e dey linked wit: Brentford, Tottenham, Manchester United Christian Eriksen suppose dey half way to a four-and-a-half year contract wit Inter Milan. But, di 30-year-old bin get cardiac arrest wen im bin dey play for Euro 2020 last June for Denmark, dat incident change im career, e return to football afta e fit Implantable Cardioverter Defibrillator (ICD). After dat issue Inter release Eriksen - because di ICD device no dey permitted for Serie A – e move to Brentford on a six-month deal where im quality shine through as he help di team secure their Premier League status. Di Bees dey keen to keep di former Ajax playmaker but di koko na na whether e go stay for London or head elsewhere dis one wey di likes of Manchester United dey torchlight am? Current club: Manchester United Who e dey linked wit: West Ham United, Newcastle, Tottenham, Roma, AC Milan Jesse Lingard dey leave Manchester United afta e come from dia academy and spending two decades wit di club. Wit United surprisingly decide to keep di England midfielder last summer, di 29-year-old endure a difficult 2021-22 campaign and dem use am small-small utilised sparingly. Before dat successful loan switch to West Ham for early 2021 to serve as a reminder of im qualities and finding a new club where im dey guaranteed playing time for a World Cup year fit entice am. Current club: Barcelona Who e dey linked wit: Chelsea, PSG Things neva really go according to plan for Ousmane Dembele since e join Barcelona in one of si most expensive deals of all time from Borussia Dortmund for 2017. Still only 25, injuries don affect di France forward development meaning say e don only show glimpses of im rich talent. When e dey form im pace, trickery and ability to run opposition defences ragged fit make di Nou Camp fans to love am. Although dem dey link am with a move away, club president Joan Laporta and head coach Xaxi dey b hopeful say dem fit persuade am to stay. Current club: Manchester United Who e dey linked wit: Real Madrid, Arsenal, Atletico Madrid and Juventus. Edinson Cavani two years for Manchester United dey mixed. Di 35-year-old Uruguay forward, wey arrive on a free transfer from PSG for October 2020, bin start brightly wit17 goals in all competitions for im first season. But as Cristiano Ronaldo arrive and endless list of injuries see am struggle last term. His personality and experience still dey valuable for prospective suitors. Current club: Manchester City Who e dey linked wit: Botafogo, Flamengo, Corinthians, Athletico Paranaense Fernandinho, wey be 37 years, make 19 Premier League appearance as e help Manchester City to dia fourth title in five seasons. Di Brazil international don already express a desire to move back to im homeland when im leave City, where im win five top-flight titles, six EFL Cups and FA Cup. Current club: Atletico Madrid Who e dey linked wit: Juventus, Aston Villa, Sevilla, Inter Miami At 35, Luis Suarez na another wey dey veteran category, wit im departure from di Wanda Metropolitano, last season e score 13 goals in all competitions. Di Uruguay international fit no dey as dynamic as im bin dey wen im young years but immovement around goal fit tempt several clubs to offer am a short-term offer. Current club: Real Madrid Who e dey linked wit: Sevilla, Arsenal, Tottenham Isco go pack im bags from Bernabeu dis summer as a five-time Champions League winner and three-time La Liga champion. Im still dey di prime of im career, di 30-year-old playmaker go look to rediscover im mojo afta falling out of favour at Madrid and lose im spot for Spain squad." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cg36883gn9zo +sports Big transfer deals for English Premier League on Monday "Two of di top six clubs for English Premier League confam new signing to dia squad on Monday. Manchester City, Arsenal and Leeds do deals for di transfer market while Manchester United reach verbal agreement wit one player Dis na Transfer deals wey happun for English Premier League today. Arsenal manager Mikel Arteta complete im fourth signing of di summer. E sign Brazilian striker Jesus from reigning champions Manchester City for £45m. Arteta don already bring in midfielder Fabio Vieira, goalkeeper Matt Turner and Brazilian forward Marquinhos. Arteta say ""Belle sweet me say Jesus' don show."" ""Di club do good job to recruit player of im stature,"" e tok. Jesus, go wear number nine shirt for di Gunners, e leave City afta e spend five-and-a-half years dia. E make 236 appearances and score 95 goals for dem, winning four Premier League titles, three League Cups and FA Cup. ""Na big deal for me to play for Manchester City,"" Jesus tok. ""I feel say I don improve pass wen I first come - and to win 11 trophies dey amazing. My four Premier League titles dey special for me. Manchester City sign Leeds United midfielder Kalvin Phillips for £45m. Phillips wey be 26-year-old England international sign a six-year deal wit di Premier League champions. Im be Pep Guardiola third summer signing afta di arrivals of Erling Haaland and Stefan Ortega Moreno. ""I dey very happy to join Manchester City. City again prove say dem be di best team for di kontri,"" Phillips tok. Phillips, bin make 235 appearances for ova eight seasons for Elland Road, and im bin still get two years left on im Leeds contract. Denmark midfielder Christian Eriksen has agreed in principle to sign for Manchester United on a free transfer. Denmark midfielder Christian Eriksen don agree to sign for Manchester United on a free transfer. Eriksen short-term contract for Brentford end last month. Tori be say Eriksen for return back to Thomas Frank side, but di temptation of playing for United been dey too big to turn down. Na three-year contract na im United dey prepare for Eriksen, wey still need to do im medical for Old Trafford. Eriksen fit be United and new manager Erik ten Hag second signing of di summer transfer window, wit Feyenoord defender Tyrell Malacia undergoing a medical for Carrington ahead of im move. Di Dane bin return to di English top flight when im join Brentford for January afta im release from Serie A club Inter Milan. Fulham sign Portugal defensive midfielder Joao Palhinha from Sporting Lisbon on a five-year deal for a reported fee of around £17m. Di 26-year-old na Fulham boss Marco Silva first signing since gain promotion to Premier League for May. Palhinha bin help Sporting reach di Champions League last 16 last season. ""Na big opportunity for me, for my career to play for wetin- for me – be di best league for di world,"" e tok. ""I sign wit a great club. Di club want me, and I choose di club, so I promise di fans say I go my best, and I hope we fit win so many things dis season,"" e add put." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c8985zxp792o