diff --git "a/data/pcm/dev.tsv" "b/data/pcm/dev.tsv" new file mode 100644--- /dev/null +++ "b/data/pcm/dev.tsv" @@ -0,0 +1,153 @@ +category headline text url +health Coronavirus in Kenya: 'I bury my cousin on Facebook Live' "Dem place di chairs at least 1m (3ft) apart - family sidon for one side, church officials for di oda. Evribodi wear facemask. Evrione know di serious instructions wey di Kenyan goment don put for burials during di coronavirus pandemic. Only 15 pipo gather for di burial of my cousin, Chris, and everytin need finish by 09:00 local time. By 07:00 di rest of us gather, in front of our phones and computers, dey watch as di burial dey happun as my friend live-stream am on Facebook. Hundreds of us watch to pay our last respect to Chris. Im be pipo pesin - di life and soul of family parties. Im deep laugh go reach you even before e set foot inside di house - in fact, you fit hear am 200m away for gate. And Chris normally dey show up for pipo, weda na burial or weddings. E sabi ginger pipo for all occasions. So, on dis day, we show up for am too. But as we no dey dia, e no feel like na di same tin. Chris na my immediate cousin, but dem raise us for di same house and im bin be more like brother to me. Im die for Kisumu for western Kenya on Easter Sunday, afta e sick for few weeks wit liver cirrhosis. Di goment give us di guidelines for e burial. We gatz bury am within three days. But wit many of e family and friends under lockdown for di capital, Nairobi, no be evribodi fit attend di burial. Di sermon bin dey short. Di speeches bin dey restricted. And even singing no too dey. Chris bin love music wen e dey alive - im play di drum kit for di Salvation Army church band. So e dey painful say nobodi bin dey dia to play im favourite songs. I watch as live comments from e friends and colleagues begin appear in on Facebook. In order to use internet comfort demsef, pipo leave RIP messages and tok of how great a man Chris be wen im dey alive. And I bin tink say, maybe I for take screenshots and print am out becos dis mainly become our condolences book. Everytin bin feel so different. We no fit hug, touch or see each other tears. We no fit throw sand on di coffin as dem dey put am for grave. When pesin wey you love die, we wan cry, look for comfort and closure. But how yo go do dis kind tins wen you no dey dia? I bin vex. I no ever imagine say I go bury my loved one through social media. I no ever tink say I go want human contact that much. E bin dey like feem, except say I dey part of pipo wey act am. And sadly, di Facebook Live fail, due to a poor network connection. So I no fit even watch Chris final journey to di very end. I no see wen dem put e coffin down inside grave. For many African societies death and life are dey togeda. Many traditions see death as rite of passage - a transition to another form. Hence why ancestors dey important - dem be di pipo wey don die but kontinu to ""live"" for di community. Dis, in turn, mean say wen pipo die dem must receive perfect burial - complete with rituals wey dem don observe for generations. For di communities for western Kenya wia I come from, like di Luo and Luhya, wen dem born pesin die and wen di pesin die na two important events. Dem dey treat pesin wey die wit respect and death and burial process dey to follow, to ensure mistake no dey. First of all burials dem no dey rush burials, especially for old pesin. Pesin death na call for celebration, even though pipo dey mourn and cry. E dey take at least one week to bury adult pesin. Loud mourning and crying, go last for days. Pipo come togeda to help di family of di pesin wey die to mourn. Dem go light Bonfire and pipo go gather around dem, embrace, cry, and relive di life of di pesin wey die. To kill animal dey part of di ritual, and di preparation and serving of food and drinks to console mourners. Na show of unity amongst neighbours and family. Dem go bring di dead home a day or two before di burial. They lie in di compound, to show say dem accept and love dem, even in death. Di Luo, a Nilotic people from western Kenya, have among di most elaborate burial customs for Kenya. At least 10 rites dey involved from the announcement of death, to di removal of di shadow or spirit of di dead from di homestead, to di shaving of family members' hair, and finally di remembrance ceremonies for di dead. All dis occasions require pipo to gather and interact in huge numbers. But during dis pandemic, most of dis rituals are dey off-limits, whether di pesin die of Covid-19 or not. During di two days between Chris' death and e burial, dem forbid pipo for house to sing with loud voice for night, becos dem go attract di neighbours wey go want come cry wit di family. Dem no light any bonfires to sit around. And during di burial, even for grave site, no hugging, or touching, no handshakes or kisses dey allowed. Goment representatives bin dey dia to ensure say pipo follow di rules f social distancing. Forty days afta dem bury somebody, dem suppose hold memorial service - di final celebration of dia life. Again, we no go fit do dis for Chris. I get dis feeling say I don only partially cry for Chris. Dis no be how e for deserve make pipo mourn am. Maybe wen all dis end - when we fit hug again, and cry for each other arms - we go mourn am like we suppose." https://www.bbc.com/pidgin/world-52781527 +sports Messi release clause 2020 from Barcelona - Dis na wetin we know Six-time Ballon d'Or winner and Ogbonge Barcelona player Lionel Messi don tell di club say im wan leave dis summer. Messi wey be 33 years old send di club fax on Tuesday to say im wan use di part for im contract wey go allow to leave free of charge with immediate effect. Dis dey come afta Barca chop 8-2 beating from Bayern Munich for di Champions League quarter- finals for August 16. Di Argentine player first play for Barca for 2004 and e don win Champions League four times. Di board go meet soon and some pipo feel say di only thing wey fit calm am down na if dia president Josep Maria Bartomeu resign and dem do early elections. But Messi dey determined to leave di club no matter what. Messi bin sign new contract extension for 2017 wey go keep am for Camp Nou through di 2020-21 season—and make am di world highest-earning football but dem add one new exit clause. E go allow am to leave for free dis summer as long as im tell dem of im decision before June 10, 2020. Barcelona believe say dat part of di contract no old water again and Messi still dey under contract wit di club until 2021 with 700m euro buy-out clause. Messi join Barcelona at di age of 13 from Newell Old Boys for Argentina for 2000, and im don score 634 goals wey be club for 731 appearances. Im don win 34 major trophies wit di club, including 10 La Liga titles and four Champions League trophies. Dis na some records wey Messi hold: https://www.bbc.com/pidgin/sport-53916292 +politics Oyigbo Rivers state news: Latest on wetin dey happun for di area "Days afta Rivers State goment declare 24 hours curfew for Oyigbo local goment area, and residents say di area don calm small as at di morning of 3 November 2020. Victor Bassey wey dey stay for Komkom area tell BBC Pidgin say dem neva hear any gunshots as e bin dey before but security agents still dey patrol di area. Rivers State goment bin declare 24 hours curfew for di local goment area and oda parts of Port Harcourt City after violence scata End Sars protest on 21 October, 2020. Goment blame suspected members of di Indigenous Peoples of Biafra (IPOB) come result in di burning down of three police stations and Court premises for Oyigbo. Soldiers and three policemen die for di gbege. By 28 October, Governor Wike come lift di curfew for parts of Port Harcourt but say di 24 hours curfew go still continue for Oyigbo. But since dat Wednesday, tension don increase for di Oyigbo area as many pipo wey dey live dia begin run comot sake of say security pipo begin patrol di area to enforce di curfew. Plenti tori bin full social media about military action for Oyigbo. But we no fit verify most of those claims. Charles Akah wey dey live for di area, bin tell BBC Pidgin say na inside house dem dey since di Rivers State declare 24 hours curfew on 21 October, 2020. ""Army pipo dey arrest young boys na wetin we hear so pipo dey fear to comot for dia house."" We no fit go withdraw money or even buy sometin so tins hard. Make goment look dis matter gain."" Anoda pesin Bani Jackreece tell BBC Pidgin say na around 4am for morning on Sunday 1 November, she find way run comot for di area as she no feel secure to continue to stay dia. Jackcreece say since di state goment continue di curfew for di area, soldiers and security pipo for di area no dey allow dem come out and now tins dey difficult for pipo wey dey stay dia. ""We hear say security pipo dey go round arrest pipo wey dey involved for di End Sars violence wey happen for Oyigbo wey result in di burning down of police stations and court premises dia. Tins dey hard as pesin no fit come out to go withdraw money for ATM or even go buy sometin chop because if di security pipo see you come out, dem go drive you go back. Hunger dey because pipo no prepare at all,"" she bin lament. Police tok tok pesin for Rivers State Police Command Nnamdi Omoni bin tell BBC Pidgin say im no dey aware of any arrests wey happen dia as nobody report give dem but say security operatives wey dey enforce di curfew don bring relative calm for di area. Efforts to reach Maj. Charles Ekeocha, di tok tok pesin for 6 Division Nigerian Army for Port Harcourt as tori comot say army dey do house-to -ouse search dey arrest pipo, no dey successful. Rivers State Governor Nyesom Wike announce say di State Security Council go meet to take decision on wetin dem go do next for Oyigbo. Many pipo dey expect say di goment go lift di curfew as many pipo wey dey live and do business dia say tins hard for dem as dem no get light and dem no fit come out come buy food or withdraw money sake of di curfew. Meanwhile, Rivers State Police Command don parade four suspects wey allegedly loot Afam Police Station during di attack on some police stations for Oyigbo on 21 October 2020. Afam Police Station na one of di three police stations dem burn down for dat attack, wia six soldiers and three policemen die. But di four suspects deny say dem directly participate for di destruction of di Oyigbo police stations but say dem keep some of di looted items wey include 21 inch television set, radio speakers and police uniforms." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54765047 +politics Muhammadu Buhari: We no apologise to President - House of Representatives "Nigeria House of Representatives don deny tori wey dey fly upandan say members of di 9th assembly tok sorry to Nigeria President Muhammadu Buhari because dem invite am to come address dem on top insecurity mata for di kontri. Chairman Committee on Media and Public Relations wey also be di tok-tok pesin for di lawmakers, Benjamin Kalu tok dis one for inside statement. Di statement tok say di report wey some media houses carry say lawmakers go beg di President afta dem agree to di motion wey members from Borno state sponsor wey request di invitation of di President to brief di nation on di state of insecurity for di kontri na fake news. Di lawmakers for December 1, 2020 resolve to invite president Muhammadu Buhari to come address dem on top di security situation for di kontri but di President no show face for di assembly. Legislators for Borno state bin cari cry go di floor of di house come raise wan kain serious motion say make goment declare state of emergency plus make president Buhari appear before di house to explain to dem how e dey tackle security mata. Dem also bin dey para on top how Boko Haram bin kill 43 rice farmers like chicken. After di president bin accept di invitation, Attorney General, Abubakar Malami say lawmakers no get any constitutional right to invite di presido to come address dem. E say di president get to hold security issue wit confidentiality and dat di House of Representatives operate outside di constitution. Oga Kalu for di statement say: ""di House no apologize to anybody, dem carry out dia constitutional mandate and di 9th assembly of di House of Representatives under di leadership of di Speaker Femi Gbajabiamila no go do anything wey go destroy di democracy of di institution." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55464381 +sports Roger Federer go retire later dis month "Roger Federer, wey be 20-time Grand Slam singles champion, go retire from top-level tennis afta di Laver Cup for London later dis month. Swiss Federer wey be 41 years old, neva play since Wimbledon 2021, afta wen e do third knee operation. ""My body message to me dey clear,"" Federer tok. ""I don play more dan 1,500 matches ova 24 years. Now I must recognise wen time don reach to end my competitive career."" E add say: ""To di game of tennis, I love you and go neva leave you."" Federer don struggle wit knee problem for di past three years wey don restrict am to only three of di 11 Grand Slams since di start of 2020. E neva play competitive match since e lose to Hubert Hurkacz for di quarter-finals for Wimbledon last summer. E later announce say e need more surgery for im knee afta e don previously get two operations for 2020 Only Spain Rafael Nadal, wit 22 majors, and Serbia Novak Djokovic, wit 21, get more men Grand Slam singles titles dan Federer. ""Dis na bittersweet decision bicos I go miss evritin wey di tour don give me,"" Federer tok. ""But, at di same time, so much dey to celebrate. I consider mysef one of di most fortunate pipo on Earth. Dem give me special talent to play tennis and I do am for level wey I neva imagine for much longer dan I don eva tink of di possibility."" Aside from thanking im family, support team and fans, Federer also thank im opponents from one golden era of di men game. ""I dey lucky enough to play so many epic matches wey I no go never forget. We battle fairly, with passion and intensity, and I always try my best to respect di history of di game. ""I dey extremely grateful. We push each oda, and togeda we take tennis to new levels."" Federer make im professional debut for di age of 16 for1998 and win im first Grand Slam title for Wimbledon for 2003. E dey end im career wit record total of eight men singles victories for di All England Club. Federer final Grand Slam triumph come for di 2018 Australian Open wen, for di age of 36, e become di second-oldest man to win major singles title for di Open era. Afta e rise to world number one for di first time for 2004, e spend 310 weeks as di leading player for di ATP Tour during im career - one record wey e get until Djokovic pass am for February 2021. E retirement announcement dey come less than two weeks afta 23-time Grand Slam singles champion Serena Williams play wetin dey expected to be di final of her career for di US Open. Federer na di most successful grass-court male player of all-time ontop im beta Wimbledon success, wit di last win for di All England Club coming for 2017. Di Australian Open na di next most successful major tournament for di Swiss, wia e win six titles for Melbourne Park between 2004 and 2018. E claim all five of im US Open title in a row between 2004 and 2008, while im one and onlywin on di French Open clay come in 2009. Di chairman of di All England Lawn Tennis Club, Ian Hewitt, congratulate Federer for im ""truly remarkable career"". ""Dem go celebrate am forver as one of our greatest Wimbledon champions, afta e lift di trophy eight times from im 22 appearances for di All England Club,"" Hewitt add. ""I hope say, in retirement, Roger go fit look back with big satisfaction and pride on all im accomplishments and di high esteem wey di tennis community take dey look am."" Argentina Juan Martin del Potro, wey defeated Federer to win di 2009 US Open, pay fulsome tribute to im rival. ""I love you Roger,"" e tweet. ""Thank you for everything wey you don do for tennis and with mysef. Tennis world go neva be di same without you."" 20 Grand Slam singles titles 310 weeks as world number one 103 ATP titles 28 Masters 1,000 titles 6 ATP Finals victories 31 Grand Slam finals 1 Davis Cup triumph £114m career prize money" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyde86018m9o +sports Ghana win Nigeria to qualify for CHAN 2023 - Full match report Nigeria Chan Eagles play Ghana Black Galaxies 2 - 0 on Saturday afta full time for dia final round of qualifiers for Caf 2022 TotalEnergies African Nations Championship. For di first leg, Ghana beat di Nigeria 2-0 for Cape Coast Stadium on Sunday 28 August, 2022. 30 Nations dey compete for di remaining 15 spots for Algeria 2023. Two west African heavyweights, Ghana and Nigeria meet for MKO Abiola National Stadium, Abuja wen match kick-off 17:00hrs WAT. Dis result mean say Ghana still close mark Nigeria on two-two on goal aggregate. So di game enta penalty kick. Penalti kicks end Nigeria 4 - 5 Ghana. E mean say Ghana win Nigeria one nil on goal aggregate and don qualify for 2023 CHAN Penalties: Nigeria score dia fifth leg, Ghana also score dia fifth kick. Penalties: Nigeria score dia fourth leg, Ghana also score dia fourth kick. Penalties: Ghana score all first three kicks Penalties: Nigeria score all first two legs but miss di third kick. Penalties: Nigeria go take di first kick! FT: We go straight into penalty shoot outs - NGA 2-0 GHA [2-2 aggregate]. 94' Di home side wit a late goal hia and it’s 2-2 on aggregate - Akunetooooooo goal! Nigeria 2-0 Ghana ( 2-2 Agg) 90' Four mins of additional time don dey added. 88' Danlad put out one spectacular save to deny Nigeria a goal hia. 87' Three mins to full-time and Black Galaxies still dey hold on to dia 2-1 aggregate lead 80' Ten mins to go! Ghana dey down but still get dis one well under control, 76' Goal for Nigeria: Zulkifilu Muhammed score for di Chan Eagles. Nigeria 1-0 Ghana (1-2 Agg) 72' Umar Bashiru and Jonah Attuquaye on for skipper Gladson Awako and Dominic Nsobila - Substitution for Ghana 67' Two changes coming up for Ghana. 58' Nigeria wit anoda free kick for edge of Ghana 18-yard box and e go out for a corner kick. 55' Suraj Seidu makes way for Amos Acheampong of Ghana - Substitution 46' Second half begin for MKO Abiola Stadium, Abuja 45' First Half end 0-0 and dem go break inside Abuja. 25' Nigeria third corner kick go off di game and dis one end in di net but dem rule am out as offside 12' Free kick to Ghana on di left side of di Nigerian defense and captain Awako take dis one 10' Anoda corner kick to Nigeria but e dey headed out from di Galaxies 5' Corner kick to Nigeria but di kick off get out for a throw-in. 1' Game kick-off for MKO Abiola Stadium, Abuja Adewale - Goal Keeper Eyinnaya Duru Nosiru Oluwatosin Gbadebo Valentine Madu Nwabodo Zulkifilu Bello Danlad Ibrahim (Goalkeeper) Augustine Randolph Dennis Korsah Konadu Yiadom Mohammed Alhassan Razak Kassim Gladson Awako (Captain) Seidu Suraj Dominic Nsobila David Abagna Daniel Afriyie Barnieh By Daniel Semeniworima https://www.bbc.com/pidgin/articles/ckmyrzg2n4ko +entertainment Baba Suwe died: Facts about Babatunde Omidina, di Nigerian comedian wey die "Babatunde Omidina, di Nigerian popular comedian wit di stage name Baba Suwe die on Monday, 22 November, 2021. ""Dis na to announce di sudden death of my father Mr Babatunde Omidina. Di legend and rare gem "" Babasuwe "" 11/22/21."" Na so Sola Omidina, son of Baba Suwe post di news of Bab Suwe death. Here na five facts you need to know about di Nigeria Veteran comedian; Before Baba Suwe die, rumours bin kill am two times for social media for 2019 and 2020. For one instance, di late veteran actor bin even do one youtube video to tell pipo say e still dey alive. Dem born Babatunde Omidina aka Baba Suwe on August 22, 1958, for Inabere Street for Lagos Island. But di legendary actor come from Ikorodu local government area of Lagos. E marry e wife, Omoladun Omidina wey also be actor for 1995 and she die for September, 2009. Babab Suwe die for di age of 63. Di popular actor bin attend Jamaitul Islamial Primary School for Lagos, and Children Boarding School, Osogbo. After im boarding school, Baba Suwe bin get im West African School Certificate for Ifeoluwa Grammar School for Osogbo, Osun State, southwest Nigeria. Baba Suwe begin acting career for 1971 and e dey acts for both English and Yoruba language films. Di veteran Nollywood comedian dey often play di role of confuse servant or security guard. E become popular afta e feature in one movie titled, Omolasan. Im become more popular afta e act for Iru Esin wey Olaiya Igwe produce for 1997. Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin arrest Baba Suwe afta dem accuse am of trafficking cocaine for 2011. As di agency put am for custody sake of say dem want make e excrete di cocaine wey dem suspect say e dey im stomach, nothing come out of Baba Suwe belle. Di agency chop blame ontop di case and court come judge say make dem pay Baba Suwe more than $155,000 as compensation and apologise to am." https://www.bbc.com/pidgin/media-59378060 +entertainment End of the year quotes: Soro Soke, Wahala be like and oda trend tok wey Nigerian youths use "As di year 2020 dey draw im curtain, make we torchlight di words, tok and slangs wey di young generation for Nigeria don make popular. Many of dem you go don sabi, see di top ones we locate plus dia meaning and origin. Di tori of di recent July 2020 EndSars movement from Nigeria wey cause di goment to agree say Police need reform, no go dey complete without ""Soro soke"" and im sibling ""Soro soke werey"" - as di two of dem dey go together like 5 and 6. 'Soro soke werey' na Yoruba words wey mean open your mouth (soro) and tok loud (soke) craze pesin (werey). Di Nigerian youths use dis slang to take ginger demsef to comot, do peacful protest and raise dia voice over police brutality and oda injustice wey dem don see. Online and offline, di youths say dia generation na di 'soro soke' generation. But soro soke werey don already be popular slang for social media even before EndSars. Many say na one ogbonge Nollywood actress - Veteran Nollywood actress, Lola Idije (real name Toyin Afolayan) wey tok am inside one feem, make am popular. Dis slangs become popular for social media but from wia e take start, nobody really know. Wahala for who no, na im first land and na wetin pesin go take joke yab imself or anoda pesin if dem no get something. Some go use am like dis: Wahala for who never travel before or, Wahala for who never marry. Then in di last months of 2020, di wahala slang carri anoda head come: Wahala be like... to complete wit something wey funny about di challenges of 'wahala', like: Wahala be like noodles, two minutes e don ready and wahala be like Uganda, e de easy to enter but difficult to comot. Dis one show face around early 2020 and na question wey dey ask why something wey no suppose surprise pesin, surprise am. Some say na comedian, Broda Shaggi make am popular. But as wit dis kain tins, e go dey hard to confam. Di originator for dis one na Naira Marley, di president of Marlians. Di Nigerian musician no be stranger to dey use slangs inside im songs wey many of im followers go in turn carry for head. O por or Opor in Yoruba mean say enjoyment full everywia or say something happun wey dey very big. Na di artiste also make Mafo blow - Mafo na also Yoruba wey mean not to break, or make pesin stand gidigba, no to shake when wahala show face. Werey dey disguise (Craze pesin dey hide imself) I shook! Drip On God" https://www.bbc.com/pidgin/tori-55434559 +entertainment Maraji: Nigeria Instagram comedian don break internet wit her pregnancy announcement "Ogbonge Nigeria Instagram comedian Gloria Olorunto alias Maraji don announce her pregnancy on Monday, 20 December. She do di announcement thru video wey she post for her Instagram page. For di video, Gloria pregnancy dey show as she dey dance to Beyonce music. Congratulation messages from her fans na im full di comment section of di video as dem express dia happiness for her. Some Nigeria celebs also tuale di comedian for her pregnancy. Chioma Akpotha, Nollywood actor, producer and director send message say ""congratulations dear."" YouTuber, Steve Chuks, send her ""congrats."" Brand influencer and actor Bukunmi Adeaga-Ilori say ""Awwwwwww. Marajiii."" E still get some fans wey congratulate her for getting married plus di pregnancy. Damilola.A say: ""Marriage and pregnancy announcement in one post! Love it! Congratulations Maraji."" D Rarity Nma comment say: ""A ring & a bump.😍😍 ok sis... show up!!! Show out !!! congrats babe."" Di comedian bin disappear from social media for some time before she reappear wit dis dance video. Maraji wear ring for her wedding finger but e neva clear weda na ""DI RING.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-59732265 +entertainment Korra Obidi marriage: Justin Dean divorce plans make Korra apologise to her fans wey look up to her marriage "Afta period of silence, Nigerian dancer Korra Obidi don come out come tok about di state of tins for her marriage. For video wey she post for Facebook, she say ""You fit see me, looking strong dancing, and because I dey try hold tins togeda. I wan dey strong for my girls"" She add say dance na di way wey she dey take cope. Dis na di first time wey di dancer go address one post wey her husband make wey e say im wan divorce im wife of four years. Di celebrity dancer tell her fans for di video say she bin no wan come out to tok on top say di internet no dey ever forget. Even as she add say, ""I wan apologize to my fans wey come my page see perfect marriage, and now tins dey fall apart"". ""I dey sorry to all my queens wey dey look up to my marriage, say I wan get dat some day, say I don scata di illusion of perfect marriage,. Na just content creator I be."" For di post wey her husband, Justin, bin put and on social media wey im don since delete, e tok say: ""@korraobidi and I dey divorce. It's over! Pesin no go treat me like dis again. I bin do my absolute best to make am work"". Di couple bin marry for December 2017 and don get two pikin dem June and Athena. On her part, Korra say: ""I don dey see una comments and I just wan say I no go come here and tok bad about my husband because I no say e go dey damaging to my family and I no go do dat."" Di Chiropractor bin reveal dis one for im social media wia e accuse Korra Obidi say she dey narcissistic and of cheating. Howeva Korra no chook mouth put inside di accuse, she just tok say, ""It takes two, for evri marriage, e takes two"". She add say, ""in time, wen I don strong, I go tok my own side of di tori. But till then abeg be kind with una words."" Di mama of two, hala say na only she one dey for her pikin dem for America and if she breakdown, her two year old, June and her new born baby Athena no go get any bodi as none of her family dey close by am. Since her husband accuse comot, di last time Korra tok anytin, na wen she thank her fans wey bin check up on her for Instagram tori. Since dat time, she neva tok anytin and just dey release her dance video as usual, and e don make plenti pipo dey ask am, why she dey dance instead of to dey take care of her marriage. She bin bion comot for some of di pipo wey bin ask her to dey stop posting videos say how she go take make money if she stop. One week, afta di birth if dia second pikin, Justin Dean, enta social media to annouce di end of im marriage. Last week, im bin reveal say e dey for di process to file for divorce afta four years of marriage. E accuse Korra Obidi say she dey nonchalant of dia relationship. And also refuse pipo thought say di reason for her ""behaviour"" na post partum depression. So far e don delete most of dia videos togeda for im page, including di one of di home birth for im daughter athena." https://www.bbc.com/pidgin/media-60778322 +sports Conor McGregor beat Donald Cerrone in 40 seconds for UFC 246 for Las Vegas "Conor McGregor retun to di octagon ring wit first-round victory over American fan favourite Donald 'Cowboy' Cerrone for Las Vegas. Na just 40 seconds McGregor use defeat am. Irishman McGregor, 31, claim victory for wetin sabi pipo say fit be im best performance of im career. Two of UFC fighters wey popular pass enta same trouser for di main event area of T-Mobile Arena. But referee Herb Dean step inside and wave say di contest contest don end afta blow afta blow land ontop 'Cowbow' ""I make history tonight. I set new record. Na me be di first fighter in UFC history to give knockout victory for featherweight, lightweight and now welterweight - across three weight divisions, so I dey very proud of that,"" tok McGregor. Di last time im win inside UFC octagon ring na wen e get im second UFC world title for November 2016, and afta undefeated UFC lightweight champion Khabib Nurmagomedov defeat am for UFC 229 for October 2018. ""I like dis weight division. I feel really good. God willing, I come out with no injury. I dey in shape. Although, I no believe say I don reach dia. I still work to do to return to how I be before.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-51166186 +sports Transfer rumours: Suarez, Kane, Lukaku, Haaland, Salah, Pochettino Aston Villa manager Steven Gerrard dey monitor Atletico Madrid Uruguay striker Luis Suarez, 35, wit di prospect of making im move dis summer. (Athletic - subscription) Manchester United dey consider fresh summer move for Tottenham 28-year-old England striker Harry Kane. (Mirror) Lionel Messi papa and agent Jorge don call Barcelona to discuss weda di 34-year-old Argentina forward fit return after im leave last summer for Paris St-Germain. (90min) Barcelona go consider move for Chelsea Belgium striker Romelu Lukaku, 28, if dem no fit sign Borussia Dortmund Norway forward Erling Braut Haaland dis summer. (AS via Star) Barcelona manager Xavi dey keen on di all round ability wey Liverpool Egypt striker Mohamed Salah, 29, go add to im side. (AS - in Spanish) Arsenal manager Mikel Arteta and Tottenham boss Antonio Conte dey nine-man shortlist for di Paris St-Germain job if Mauricio Pochettino chop sack. (L'Equipe via Mail) AC Milan believe Lille Dutch defender Sven Botman, 22, and Portugal midfielder Renato Sanches, 24, go sign for dem imminently. (90 Min) Liverpool no go sell or loan Ireland goalkeeper Caoimhin Kelleher, 23, during di summer transfer window despite interest from Premier League clubs. (Sun) Manchester City dey set to join Real Madrid and Manchester United in di race to sign Bayern Munich Poland striker Robert Lewandowski, 33, if im dey available in di summer. (Fichajes - in Spanish) Leeds United Brazil forward Raphinha, 25, dey enta Barcelona and Manchester United eye. (Football Transfers) Liverpool also dey interested in Leeds' Raphinha. (Fabrizio Romano) Liverpool dey close in on di signing of Scottish 16-year-old full-back and winger Ben Doak from Celtic. (Athletic) Fiorentina dey in talks with Arsenal over permanent deal for 26-year-old Uruguay midfielder Lucas Torreira, wey dey on loan. (Fabrizio Romano) Benfica dey eye Paris St-Germain 34-year-old Argentina forward Angel di Maria. (Record - in Portuguese) Lazio Albania goalkeeper Thomas Strakosha, 26, na target for Premier League clubs. (Calciomercato - in Italian) Real Madrid 25-year-old Spain midfielder Dani Ceballos, wey spend time on loan for Arsenal between 2019 and 2021, dey face uncertain future for Bernabeu. (AS - in Spanish) Barcelona dey close to complete di signing of Morocco defender Noussair Mazraoui, 24, wey dey out of contract with Ajax at di end of di season. (Sport) https://www.bbc.com/pidgin/sport-60749114 +sports Super Falcons' Olympics dream end afta Cote d' Ivoire pour sand-sand for dia garri Nigeria Super Falcons don troway dia chance to go Tokyo 2020 Olympic Games afta Cote d' Ivoire waya dem 1-1 ontop home soil for second leg qualifier on Monday. For match wey dem play for Agege Stadium Lagos, Nigeria lose based on di away goal rule because na goalless draw dem play for first leg. Dis na di third time wey di African champions no go qualify for major sporting event wey dey happun everi four-four years: For 2012 (London) and 2016 (Rio de Janeiro). Now dem need to wait for anoda four years (Paris 2024). Les Elephantes and Super Falcons bin play 0-0 draw for Abidjan four days earlier, and Nigeria be di favourite to win am for Agege, but coach Clementine Toure and her girls decide say dem go change am for dem. Na di visitors first score afta 12 minutes from one quality free kick by Nina Zote Kpaho. Nigeria captain Asisat Oshoala equalise later for di 32nd minute. Na only one automatic slot dey for Africa and Cote d' Ivoire go feel say strong chance dey now for dem to grab am. https://www.bbc.com/pidgin/sport-49970018 +entertainment Fundraiser Erica Nlewedim: GoFundMe for BBNaija Season 5 disqualified housemate and wetin fit make fans donate over $15,000 for her "One day, afta Erica of Big Brother Naija comot di house, thousands of dollars don enta as donations for am but you ever wonder wetin fit make fans comot money dash celebrities? $15,000 and rising. Dis na di money wey fans don already donate give Big Brother Naija former Erica Ngozi Nlewedim ontop one GoFundMe page wey dem set up for am. For some na something dis kain donation to pesin wey dem fit no sabi na normal tin, but for oda pipo no be something wey dem fit ever tink to do. Abuja-based Psychologist Kareem Folajaiye say those wey donate money na di kind pipo wey feel say dem get relationship wit Erica (even if dem no sabi am personally) and because of dis, dem want epp her to overcome di loss of di Big Brother Naija prize money. Dis fans get wetin we dey call ""complicit bias"". According to Folajaiye, no be because Erica be potential celebrity, dis fans donate because dem go do am for regular pesin join. Di GoFundMe page show say na $100,000 be dia target. Wen BBC ask if dis fans wey donate dey normal, or need 'epp', Folajaiye laugh say for some of di fans dem fit get ""psychological issue"". As at di time we write di tori, na just 193 donate di $15,793 (N6,107,000). Dis money, according to how UN take estimate am, fit feed 7,896 Nigerians (as per $2 per day rule). Dis kain donation don happun before for faraway America. Wen Forbes comot rank say na $100m businesswoman Kylie Jenner need to become billionaire, some fans setup GoFunMe to add ontop di $900m wey di celebrity get." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54064420 +health Coronavirus: How COVID-19 fit be agent of peace for Cameroon As coronavirus continue to dey spread for Africa - anoda angle don dey to di tori - e fit bring peace? Armed groups all ova di world dey call for ceasefires to helep pipo concentrate to fight di virus. Dis dey happun as United Nations Secretary General, Antonio Guterres say make oda armed groups for Anglophone regions drop dia guns for helep fight Covid-19 pandemic. Antonio Guterres e call kam afta Southern Cameroons Defence Forces, SOCADEF gree for mash break for fighting for Anglophone regions. UN boss bi send global message say make all fighting stop for de world for helep fight one enemy, Covid-19. Cameroon don already confirm 88 Covid-19 cases, two pipo well go house and two die. About 500 pipo di wait for do de test and de good news na say Jack Ma Chinese billionaire dash Cameroon and oda African kontris 20,000 test kits, 100,000 masks and 1000 protection kits. Afta e call separatist fighters for Anglophone regions for drop dia guns look for peaceful solution for de fighting for Northwest and Southwest Cameroon. SOCADEF, one of de many groups separatist groups for Anglophone regions say deh go mash 14 days break for fight face number one enemy, Covid 19. Ebenezer Akwanga SOCADEF leader say deh no go fight from March 29 go reach April 12, ake international community take humanitarian action for fight dis pandemic. Samuel Sako e group, 'interin goment', say deh drop dia guns if UN monitor de ceasefire. Covid-19 na disease weh e touch nearly de whole world weh WHO don call'am pandemic. Alredi, di Syrian Democratic Forces don pause military action. President Rodrigo Duterte bin announce unilateral ceasefire for Philippines wit communist fighters. And one separatist group for di border of Cameroon and Nigeria to say dem get plan to start two-week ceasefire on Sunday, dia leader tell BBC. Just now Cameroon don confirm 88 Covid-19 positive cases and de situation di bad everi day. Anglophone crisis start for 2016 and just now more dan 3000 pipo don, 600,000 pipo don run go odas areas and 600,000 pikim dem don komot for school, 60000 dey for Nigeria. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51993921 +business Airlines strike in Nigeria update: Ibom air, Green Africa Airlines, Arik Air, Dana Air, odas go continue flight schedules as operators suspend action "Di Airline Operators of Nigeria (AON) don suspend dia plan to strike and stop flights schedule across di kontri. Di strike bin suppose start on Monday but di AON President Abdulmunaf Sarina tok inside statement wey six members of di association jointly sign say dem announce di suspension say dem do am in di interest of di national economy and security considerations. Di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) bin don say di strike no go make sense and e go amount to exploitation if airlines suspend flights afta collecting money for tickets from passengers. Di operators dey complain of di increase in price of JetA1, wey be aviation fuel. Nigeria goment bin also beg di operators to ""reconsider dia stand"" sake of di effect. Di cost of JetA1, wey be aviation fuel don increase from N190 per litre to N700, dis na according to di airline operators of Nigeria. Abdulmunaf Sarina, president of di operators for letter wey e send to Minister of Aviation, Senator Hadi Sirika say di high cost of di fuel dey affect di operation cost of airlines. E say, ""while aviation fuel worldwide dey cost about 40% of airline operating cost globally, di present hike don increase Nigeria operating cost to about 95%."" Abdulmunaf Sarina say airlines dey run at a loss sake of di situation and e no good for dia business. ""Airline Operators of Nigeria (AON) hereby wish to regrettably inform di general public say member airlines go discontinue operations nationwide wit effect from Monday May 9, 2022 until further notice."" Nigeria Minister of Aviation, Senator Hadi Sirika say true-true aviation fuel don cost and e dey affect air transport. But di minister say make di operators look for anoda means to address di mata rather dan suspend flight activities. E say, im no fit do much because mata wey concern fuel no dey under im ministry. ""While efforts to manage di situation dey on, we wish to appeal to di airline operators, even in di difficult situation, to consider di multiplier effect of shutting down operations, on Nigerians and global travellers, in taking dia business-informed decisions and actions,"" e tok for statement by im special assistant on public affairs, Dr James Odaudu. Dis no be di first time operators bin plan to take dis kain action. Wen e happun e dey affect air travel. For March dis year, di operators bin complain about di same aviation fuel but dem no fit reach resolution wit goment and stakeholders for di oil industry. Earlier dis year, airline operators increase price or air fare by 50%. For instance, a trip of N23,000 before increase to N50,000. Di operators claim say di increase for di price of tickets na sake of di high cost of aviation fuel. Air travellers complain wella during dat period but pipo still continue to travel by air. Wit di latest plan to bin suspend dia business, e no clear weda dem wan increase di price of dia ticket again. Di six airline operators wey bin sign di statement to suspend strike include Abdulmunaf - Managing Director of Azman Air; Shehu Wada - Executive Director of Max Air; and Obiora Okonkwo - Chairman of United Nigeria Airlines. Odas be Roy Ilegbodu - Chief Executive Officer of Arik Air; Abdullahi Mahmood - Chief Executive Officer of Aero Contractors; and Allen Onyema - Chairman of Air Peace. Earlier, di Ministry of Aviation bin assured Nigerians say members of AON bin dey review dia decision to withdraw services on Monday, May 9. Dem bin confam say Ibom Air, Green Africa Airlines, Arik Air, Dana Air, and odas go carry on with dia normal flight schedules. Incidents of insecurity don make some Nigerians avoid travelling by road. Di recent Kaduna-Abuja train attack by terrorists also neva comot from pipo mind. If airlines suspend dia operations as planned, Nigerians go begin look for oda means of traveling. Though Ibom airline don announce say dem no go join di suspension - only dem no go fit cater for all di thousands of travellers wey dey make dia trip by air. But di remaining alternative go come be di use of private jets or airplane charter. E get several private jet charter companies for Nigeria wey dey offer those services. Di service dey expensive. Findings show say, a 40 minute to one hour trip within di kontri, cost up to N2 million ($5,500). Some pipo fit also do join hire of a private jet wey fit carry specific number of pipo. Dem go share di bill among dem sef. E neva clear weda di airline suspension go take effect from Monday but pipo don begin reason oda alternatives." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61369130 +health Coronavirus Update: UK wan close all travel corridors from Monday "Di UK wan close all travel corridors from Monday morning to protect dia kontri from di new strains of Coronavirus wey dem neva identify yet. Di UK Prime Minister, Boris Johnson dey tok dis one as di ban on travellers from South America and Portugal It comes as begin take effect from on Friday sake of concerns about one new variant wey dem identify for Brazil. Boris Johnson tok say di new rules go dey in place until at least 15 February. Di prime minister add say e dey ""important"" to take extra measures now wen day by day di kontri dey make serious effort to protect di population. ""Na because we get hope of di vaccine and di risk of new strains coming from overseas na go make us take additional steps now to stop those strains from entering di kontri"" ""We go close all travel corridors from 04:00 GMT on Monday, afta dat arrivals to di UK go need to quarantine for up to 10 days, unless dem test negative afta five days."" About 1,280 pipo with coronavirus na im don die for UK within 28 days of positive test, making di total climb go up to 87,291. Dis latest goment figure on Friday show anoda 55,761 new cases wey dem don report - up from 48,682 di day before. Meanwhile, more than two million pipo around di world na im don die from di virus since di pandemic start, according to figure from John Hopkins University. For now anybody wey wan fly enta di kontri from overseas must get to show proof of negative Covid test before coming. Dem bin introduce travel corridors for summer to allow pipo travelling from some kontris with low numbers of Covid cases to come to di UK without having to quarantine on arrival." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55686920 +entertainment Psquare reconciliation: Paul, Peter Okoye dey back together, celebrate birthday afta 2017 """Two heads dey better than one"", na how Paul Okoye take pot im birthday message on Thursday as im an im twin brother Peter don reconcile. Afta five years of gbas-gbos between di Psquare twin, dis insta video message show say dem settle dia gbege. Di Psquare reconciliation dey come a day afta video comot wey show Peter, Paul and Jude Okoye as dem dey hug each oda. Tori start to comot say dem fit don reconcile afta di pair follow each oda back for social media sometime last week. Then Paul wife, post video wey show am dey carry both im and Peter pikin dem go shopping for America. Even on Wednesday before dia video come out, Paul bin wish im twin broda, happy anniversary. Na Nigerian singer J-Martins dey behind scenes dey make di moves for PSquare to come back togeda. Di wahala wey tori start to spread up and down for 2015, but na for 2017 everitin scata as video comot wey show di twins almost start to dey punch each oda. Na for September dat year wia di group scata even as Peter reveal say e bin dey fear for di safety of im family. Both of dem come start solo career as Paul take di name, Rudeboy and Peter go by Mr P. Rudeboy bin release hits like Audio Money and Reason With Me while Mr P release hits like One More Night and Paloma. Infact, around 2020, Paul call out Peter wife, Lola wen she wish di two of dem happy birthday, say wetin she dey do for back dey different. But dem too don squash dia beef, with pictures wey comot yesterday dey show as dem dey hug each oda. As to weda dem go come togeda to do song again, e dey remain to see. Because di first time dem reconcile for 2016, dem release back to back bangers like Nobody Ugly, Away and Bank Alert. Di dancing and singing pop group Psquare bin appear for di Nigeria music scene for 2003. De become popular as pipo begin dey hype dia dance style wey wan resemble Michael Jackson and Usher own. For dia career, dem don drop seven album and different single releases with international collabo like Akon, Jermaine Jackson and Rick Ross. Some of dia biggest hits na Busy Body, Do Me, Ifunaya and Break It. Dem win many national and international awards wey include di 2006 Headies for Artiste of di year, Song of the year, Best R&B/Pop Album, and Best music video; Best Group awards for di MTV Africa Music Awards for 2008 and 2009." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59258219 +sports Timo Werner: Chelsea wan sign German striker, Arsenal go sell Kieran Tierney? Chelsea dey in toks to sign RB Leipzig striker Timo Werner wey reports say get release clause of about £54m (BBC Sport). Tottenham Hotspur dey wait for Belgium defender Jan Vertonghen, 33, to decide weda e go see out di rest of di season or leave di club before e complete. (Sky Sports) Newcastle United midfielder Matty Longstaff never train dis week sake of uncertainty over im future for di club, Serie A side Udinese dey offer di 20-year-old Englishman wey go dey out of contract dis summer wages of £30,000 a-week. (Mail) Manchester City dey look to open contract toks with 19-year-old Spanish defender Eric Garcia sake of interest from e former club Barcelona. (Mail) Manchester United dey prepare to offer 19-year-old English full-back Brandon Williams new contract, with improvement on e current £4,000-per-week salary after e impress dis season. (The Athletic - subscription required) England left-back Ben Chilwell, 23, dey tempted by move to Chelsea later dis summer but e never ask to quit Leicester City. (Mirror) Liverpool fit win di Premier League title at 21:00 GMT on Sunday night for Everton as dia first two games back na both evening kick-offs. (Mail) Arsenal fit dey willing to sell Scotland defender Kieran Tierney, 23, to Leicester City, just 12 months afta e move to Emirates Stadium. (Express) Barcelona and France forward Antoine Griezmann, 29, say im intend to finish e career for Major League Soccer for America. (LA Times) Barcelona Croatia midfielder Ivan Rakitic, 32, go discuss potential return to e former club Sevilla for di end of di season. (Mundo Deportivo - in Spanish) Juventus midfielder Adrien Rabiot, 25, na target for Everton and Arsenal, but di Frenchman no go accept wage cut to leave di Serie A side. (Tuttomercato - in Italian) Germany midfielder Kai Havertz na target for Real Madrid, but Bayer Leverkusen sporting director Simon Rolfes say di Bundesliga club never make any decision on di 20-year-old future. (Marca) https://www.bbc.com/pidgin/tori-52932812 +sports Stuart Baxter resign as South Africa coach afta Afcon 2019 "Stuart Baxter na di ninth coach to leave im job afta African Cup of Nations finish for Egypt. Baxter wey resign say dis na di right time for am to move on ahead of di new qualifiers for Africa Cup of Nations and World Cup. Dis dey come just weeks afta South Africa reach di quarter-finals of di Nations Cup wey just end for Egypt. For di competition dem beat di host nation Egypt to reach di last 16. ""I feel say di time dey right for anoda pesin to take over as I don decide to resign from my position. Na personal decision,"" na wetin im tok. ""Going to Afcon, dis squad bin neva lose game inside one year, something wey no dey easy with all di new players wey we bring. ""I don decide say I no go blame anybody. And I decide not to react to some kain tori dem wey dey fly up and down dat also dey hard for me. "" Bafana Bafana manage to reach di last 16 afta dem lose two of dia three group matches dem. South Africa wey comot Egypt only for dem to lose to Nigeria for last minute of di game for dia quarter-final match afta dia goal keeper make mistake. Baxter wey dey coach Bafana Bafana for di second time, win 14 out of 30 matches, draw six and lose 10. Im follow Clarence Seedorf (Cameroon), Javier Aguirre (Egypt), Paul Put (Guinea), Herve Renard (Morocco), Ricardo Mannetti (Namibia), Emanuel Amunike (Tanzania), Sebastien Desabre (Uganda) and Sunday Chidzambwa of Zimbabwe wey resign or dia contract don end." https://www.bbc.com/pidgin/sport-49209441 +sports Ahmed Musa dey close to sign short-term deal wit Kano Pillars "Nigeria captain Ahmed Musa dey consider proposition to play some matches for e former club for Nigeria, Kano Pillars, for move wey di hope na to boost di local league and maintain e personal fitness. Di 28-year-old, wey be free agent since e leave Saudi Arabian side Al Nassr for October, don receive offers from England, Russia and Turkey. But as e dey tink dem over im next European destination for di summer, di winger receive proposal from di governor of Kano, Abdullahi Umar Ganduje and Shehu Dikko, chairman of di League Management Company (LMC) for short stint for Nigeria. ""After I speak wit di governor and chairman of di LMC I dey consider to play some games for Kano pillars,"" di former Leicester City player tell BBC Sport Africa. ""Anytin wey go improve di image of Nigerian football na something wey I dey strive to embark on and Kano Pillars hold special place for my heart. ""Na di team wey help me become di professional footballer I be today, so dis na more than just football but very strong bond."" Source wey dey close to di club tell BBC Sport Africa say dem don already finalise di deal to bring Musa. Musa, who has built two training and fitness facilities in Northern Nigeria to help grass roots football, scored 18 goals for Kano Pillars to finish as top scorer in the 2009/10 Nigeria Professional Football League (NPFL) season. Im desire to help promote di image of di domestic league on social media na wetin di LMC, wey dey run di NPFL, dey hope to benefit from dis season. Musa make e 96th appearance for Nigeria for their 3-0 win over Lesotho for Lagos for di Super Eagles final Africa Cup of Nations qualifier." https://www.bbc.com/pidgin/sport-56729112 +entertainment Britney Spears and Jamie Lynn enter one public gbas gbos sake of past relationship "Britney Spears and her sister Jamie Lynn don enter one public fight sake of one fresh TV interview and dia past relationship. Di singer bin accuse her younger sister say she use one interview wey she do on Wednesday to promote her new book ""at my expense"". Britney say Jamie Lynn bin ""never get to work for anything"" and di family ""love to pull me down and hurt me"". Jamie Lynn say all di things wey Britney tok ""no be di truth at all"" and she dey ""always dey there "" for her sister. Di 30-year-old also tok say she gatz to explain to her children say ""why our family continue to dey get death threats, be sake of dia aunty unclear and accuse posts, especially wen we sabi say she fit tok di truth"". Britney dey always bad-mouth her family sake of how dem treat her during her 13-year conservatorship, dat time, na her papa Jamie bin dey control her money and lifestyle. Na court bin end di arrangee for November. Britney sister bin do one interview wit ABC Good Morning America earlier dis week to promote her diary; Things wey I suppose don tok. Di book allegedly dey about her own life story, including her young daughter near death accident for 2017, her relationship wit Britney and di role wey she play for di singer delicate conservatorship wey she bin do. During di interview, Jamie Lynn bin describe herself as ""my sister biggest supporter"" and say she ""bin take steps to help"" end di conservatorship. But according to ABC, she also describe Britney past behaviour for di book as ""unstatble"", ""paranoid"" and ""twisting"". She tok for di programme say: ""When di conservatorship dey put into place I be 17 years old, I dey about to get pikin, so I no understand wetin dey happen,and i no focus on dat."" Jamie Lynnbin go on to suggest say her sister don meet her to ask if she ""go be di person wey go make sure say her boys get wetin dem need"", something wey she gree to do. But, she bin continue: ""Once I realise dat, 'you know wetin, she be conservatorship', I feel like I no just want to be part of am until maybe wen she commot for di conservatorship. So e no get me wey dey oversee funds or something like dat, and if dat one be di tin , den na misunderstanding, but anyhow, i no take steps to be part of am."" For twitter Britney say: ""I bin look at my phone and I see say my sister do her interview to promote her book. ""Di two things wey no bother me say my sister tok say be how my behaviour dey out of control. ""She no dey around me much 15 years ago dat time... so why we even dey talk about dat unless she want take me sell book ."" Britney also tok sa she still dey vex say Jamie Lynn bin performe remix of her hit songs. ""I know say e fit sound like one silly thing to plenti pipo but I write plenti of my songs and my sister be di baby,"" di 40-year-old pop star bin write. ""She never get to work for anything. Everything bin always dey given to her. ""I always be di bigger person. Dey all gas to do am and play me and I dey always sit there and take am."" She also add: ""Hope your book go do well Jamie Lynn."" Jamie Lynn Spears now respond to Britney reply, she tell her Instagram followers: ""make i dey frank, di things she tok absolutely no be di truth."" She say her bookno dey about Britney only , but add say: ""I no fit help say dem born me as Spears too, and say some of my experiences bin involve my sister."" Jamie Lynn, wey bin star for di Nickelodeon TV show All Dat and Zoey 101 and don release her own music ,say di ""unhealthy gbas gbos wey don control my life for so long"". She write: ""I don work hard since before I even become teenager, and I don build my career in spite say i no just be someone little sister. ""No sides, and I no want drama, but I dey speak my truth to heal my traumas, so I go fit close dis chapter and move forward, and I wish my sister fit do di same."" Meanwhile, tori pipo Di Sun bin report say Britney go sit down wit Oprah Winfrey for one tok-all interview later dis year. Datone never dey confirmed, but Britney bin show her interest for Twitter say she wan dey interviewed by Oprah." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59999357 +health Robert Trump: US President younger brother die for hospital "US President Donald Trump don pay tribute to im ""best friend"" and youngest brother afta im die at age 71. ""Na wit heavy heart I share say my wonderful brother, Robert, peacefully pass away tonight,"" E tok for statement on Saturday. Di president don visit im brother for New York hospital di day before im die, wey e tell tori pipo: ""Im dey get hard time."" E no dey clear wetin cause Robert Trump death. Some tori pipo for America bin don report say im don sick tey tey. ""Im no just be my brother, im na my best friend,"" Donald Trump statement also tok. ""Im memory go live on inside my heart forever."" President Trump son Eric describe im uncle say na ""ogbonge man - strong, kind and loyal pass anytin"". ""Our entire family go miss am well-well,"" e write put for Twitter. Robert na di youngest of Fred and Mary Anne Trump five pikin, and dem born am two years afta im brother Donald. Di one wey old pass among di children, Fred Jr, die for 1981. Robert spend most part of im career wit di family real-estate company, wia im rise to position of top oga. Unlike im brother, tori be say im no like publicity and e live as semi-retired man for New York state. Recently, e go court to try stop di release of im niece Mary Trump tell-all book about di president, but im no succeed. 'How My Family Created the World's Most Dangerous Man' comot on 14 July and within 1 week sell pass one million copies. According to the New York Post, Robert spent more than one week for di intensive-care unit of Manhattan Mount Sinai Hospital for June." https://www.bbc.com/pidgin/world-53791171 +health Ukraine-Russian war: Russian shelling 'destroy' Ukraine maternity hospital on 9 March "Russia forces wey surround di southern port city of Mariupol don destroy one maternity hospital, Ukraine yok. President Volodymyr Zelensky say children bin dey under di wreckage, and call on Western leaders to impose no-fly zone. Im also post video from inside di hospital, wey appears badly damaged. E neva get any imformate yet about any death or injuy, or on whobin dey inside di hospital wen di bombing dey happun. Mariupol city council say di strike don cause ""colossal damage"", and dem publish video wey show buildings wey don burn finish, cars wey dey destroyed and one very big hole outside di hospital. BBC don confam di location of di videos. Russia forces don surround Mariupol for several days, and all attempts to get ceasefire to allow civilians to leave no work. ""Di whole city dey without electricity, water, food, whatever and people dey die sake of lack of water for dia body,"" Olena Stokoz of Ukraine Red Cross tell BBC. E add say her organisation go continue trying to organise evacuation corridor. Earlier Ukrainian Foreign Minister Dmytro Kuleba say, ""almost 3,000 newborn babies lack medicine and food"" for Mariupol, and say Russia still continue to hold more dan 400,000 pipo ""hostage"". Russia insist say e no dey target civilian infrastructure for Ukraine. Meanwhile, convoy of civilians don ready to leave several towns near Ukraine capital, Kyiv, according to regional leader Oleksiy Kuleba. Ukraine armed forces agreed to stop firing on Wednesday on six evacuation routes for 12 hours, from 09:00 to 21:00 local time (07:00 to 19:00 GMT). Dem ask Russia forces to fulfil dia commitment to di local ceasefires, but Russia shelling still continue wit more reports of civilian deaths. Oleksiy Kuleba, wey dey head Kyiv regional administration, say civilians suppose to leave town like Bucha and Hostomel to di north-west of Kyiv, as several of dem under Russian occupation. ""I really hope say everytin go dey fine and we go look afta our people."" Police said convoy of buses and oda vehicles dey on dia way and dem ask residents to follow dia instructions. For separate incident dem say Russia forces don kill one policeman as im dey helep evacuate civilians from di town of Demydiv north of Kyiv. Mayor of Russian-controlled Enerhodar for south say civilians don begin enta buses to leave, but for di north-east, officials say Russia don block anoda key corridor from Izyum, southeast of Kharkiv sake of dia bombardment. One woman dey dem dey call Valentina wit her relatives for northern city of Chernihiv tell BBC say Ukraine soldiers bin prevent some long line of civilians wey bin wan leave by car on Tuesday. She speak to her relatives early on Wednesday: ""Ukraine pipo sen dem back, tell dem say dem dey fight for road. Yesterday somebody come from di oda direction of di road, so dem no close am."" She also say pipo for Chernihiv, wey dey hide inside cellars or for underground from daily Russia missile attacks, dem neva tell dem about di evacuation corridors. Ukraine managed to carry out im first mass evacuation on Tuesday, dem move about 5,000 civilians by bus from Sumy to Poltava, for centre. Di convoy take almost 12 hours to reach di city, as dem force dem to drive follow long way round areas of active fighting. BBC correspondent Sarah Rainsford watch as some of di civilians wey arrive leave crowded buses and rush for di waiting train. Many for di first convoy out of Sumy na medical students from India. One woman described two ""miserable"" weeks living mostly underground wit small supply of water and food. ""We bin dey starve,"" Manisa tok." https://www.bbc.com/pidgin/world-60669751 +health Coronavirus treatment: Immune sign dey give beta hope say Covid-19 fit dey treated "Scientists for UK don begin test one treatment dem dey hope say go fit reduce how Covid- 19 dey take affect patients wey dey sick well-well from di virus. Dem discover say dos wey di virus hook wella get small number of immune cells dem dey call T-cell. Dem go begin clinical trial if one drug dem dey call interleukin 7, wey dey always boost T-cell fit epp di patients recover. Di program get scientists from Francis Crick Institute, King's College London and Guy's for St Thomas' Hospital. Dem don look di immune cells for di blood of 60 Covid- 19 patients and dem see say di number of T-cells for dia blood don reduce. Prof Adrian Hayday from di Crick Institute say wetin dey happun wit di immune cells shock am. E explain say di immune cells dey try protect us but di virus dey kill dem. For inside one microlitre (0.001ml) drop of blood, normal adults wey dey healthy dey get between 2,000 and 4,000 T-cells, wey dem dey call T lymphocytes. Di Covid patients wey di team test get between 200-1,200. Di researchers say these findings make dem develop one ""fingerprint test"" wey fit check di level of T-cells for di blood go fit quick tell which patient case go dey serious. Manu Shankar-Hari, one critical care consultant for Guy's and St Thomas' Hospital for London, tok say about 70% of Covid- 19 patients wey im dey see for intensive care dey come wit between 400-800 lymphocytes per microlitre. ""When dey begin recover, dia lymphocyte level also go return to normal,"" he add. Dem don test Interleukin 7 for small group of patients wey get sepsis and e dey increase di production of these specific cells. Dis trial go dey for patients wey get low lymphocyte count wey don dey critical care for more than three days. Mr Shankar-Hari tok say dem dey hope say wen dem increase di cell count, di viral infection go comot. Dis research don also provide more knowledge for di way di disease take dey waka for di immune system and Prof Hayday say e go dey okay for scientists all over di world dey find clinically valuable information. ""Dis virus wey turn di world upside down dey unique - e dey different. Na something wey neva happun before."" ""Dis virus dey different and e dey give time for future research - wey we go start immediately - we need find out di mechanism wey dey give dis virus power.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52784276 +sports Odion Ighalo: Manchester United striker say im mama cry wen she hear say di club sign am "Manchester United brand new player, Odion Ighalo say im dey so desperate to play for di club sotey im agree to half im salary to make di deal happun and im no sleep di night di agreement take place. Ighalo wey be 30-year-old from Nigeria tok say im mama also cry wen she hear di news and pipo trow party for di street wey im grow up. Di former Watford striker join di red devil on load from Shanghai Shenhua until di end of di season. ""Some few oda clubs bin show interest, I tell my former club say 'abeg, just pick United, if e go dey possible',"" Ighalo tok inside statement ontop di club website. ""At 11pm inside Shanghai, my agent call me [to say] United want to do di deal, so I wake up dat night and start to dey look for translator to go di directors' room and knock im door. ""'My agent want to speak to you, United dey come for me, you need to make dis happun'."" Both Ighalo, im agent and di clubs spent di night dey negotiate and sign paper work so dat everi-everi go set before di deadline of 07:00 Shanghai time. Meanwhile, oda clubs dey call to ask Ighalo to sign for dem. ""I tell my agent say 'dis na wetin I want. I want to come here',"" Ighalo add. ""He tell me say: 'You go need to agree make dem reduce your salary for you to fit go United'. ""I come reply say: 'I no care oh. Make dis deal happun. I want to go join United. I no care how much be di pay-cut, I know dat, make e just happun'."" Ighalo say e don tey wey im na Manchester United fan, na since wen im be small boy and e dey happy say im dream to play for di Old Trafford club don come through. ""I call my mama and she dey happy, she even cry"" e tok. ""I know many pipo use to say wen dem join a team, dem go say na dia dream to play for dat team. My own no be di case. I support di team wen I dey young. ""Pipo wey know me, even back den for Nigeria, and even wen I dey play for Watford, my team-mates know say I love Manchester United, I support dem.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-51388005 +entertainment Ric Hassani, Jemima Osunde banter for twitter make Nigerians wonder wetin dey happen with di two celebrities "Nigerians on social media wake up to singer, Ric Hassani and actress Jemima Osunde bants on social media on Wednesday and e dey make fans wonder if na PDA. Di popular Nollywood actress, Jemima Osunde, first begin make pipo tok afta she comment on Ric Hassani foto on top Twitter. She do wetin plenti pipo fit tok say na brave act from a woman wey dey openly ""shoot her shot"" at a man. Jemima bin comment on Ric Hassani selfie foto say she im fit marry am, afta she tok say im snap picture like 'old man.' Whether she dey joke or not, e no dey clear, but dis comment make pipo begin tok about di possibility of love relationship between di two celebrities. Fast forward to some days later, Jemima enta twitter to complain about Lagos weather and di conversation between her and Ric Hassani ontop twitter don make dem dey trend. Jemima tweet don gada over 2,500 like plus hundreds of retweet and trust Nigerians to take di conversation further. One twitter user, @Tolu_Pepper say "" I low key like dis banter between Ric and Jemima... Maybe because somewhere in my mind I wan make dem be together."" Anoda pesin @_Inahlot wey be like say im admire di two artistes say ""If no be Adekunle Gold and Simi kinda of love or Ric Hassani and Jemima, I go rather remain single."" Although some pipo get contrary opinions about di relationship, @A6oki say ""If Jemima Agrees for Ric Hassani, thats when the Real thunder will fire Him."" @JivemanLucky also chook mouth ""Ric hassani as u dey beg jemima for dm make u no say your own thunder dey do press up too"". Di ""Thunder Fire You"" Crooner also confam for tweet say im dey toast jemima wen one fan bin try take im attention away for a 'moment.'" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56659403 +politics Wetin be 'EyeMark' App wey President Buhari launch "Nigeria president, Muhammadu Buhari don tier rubber di National Monitoring and Evaluation App wey dem call 'EyeMark.' Di Eye-Mark na new app wey go enables citizens to track goment projects in real-time. President Buhari launch di mobile App togeda with di website. E say di innovation go help to stop di practice of abandoning projects. Dis na as e be say everybody, like communities, Civil Society Organizations (CSOs), contractors, Ministries, Departments, and Agencies, and citizens go dey tok with each oda for one platform. ""Dis one mean say we must all play our roles for di success of project implementation through Eyemark."" As such, all Federal MDAs (Ministries, Departments, and Agencies) gatz use di Eyemark application as di primary tool for project monitoring and evaluation,"" president Buhari tok. During di launching, President Buhari Eyemark, wey go provide regular update on di status of capital projects across di kontri through bottom-up interactive processes, go fully dey involve for every stage. And di stage include knowing di cost, structure, benefit, and framework for maintenance afta completion. “With di Eyemark application, Nigerians worldwide fit access project information with di click of one button. ""Project data such like status, timeline, executing contractors, di amount wey dem budget and spent so far, amongst odas, go dey now available for public space.” “With di ability for citizens to give reviews and feedback in real-time on projects around dem, we dey cover di gaps wey bin dey and promote participation in governance"" di president tok. E add say Eyemark go remain one official tool for Monitoring and Evaluating Federal Government capital projects. Pesin fit discover projects on Eyemark through different ways. Di first na through di discover page wey go show; Di oda way to discover projects na through di Categories page. All you gatz do na to click on sectors and pick di sub-category wey you want like;Manufacturing, Agriculture or odas. Meanwhile, you fit also use 'sectors' categories page to look for projects for different states. Wetin you just need do na to click on di location icon, click on 'around you' and put di location you want. Oda features still dey wey citizens fit use post dia reviews on projects, share projects on social media and oda details. President Buhari note say di federal goment no fit continue to dey depend on dia few Monitoring and Evaluation teams to oversee di plenti projects across di kontri." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c9rl3y4v0v5o +sports Samia Suluhu: Tanzanians para for dia leader afta she body shame female footballers "Tanzanian President Samia Suluhu Hassan dey face yabis online afta she say female footballers get ""flat chests"" and dem no fine reach for marriage. Di president, wey be Tanzania first female leader, bin dey tok for di state house for Dar es Salaam to honour di national under-23 men football team wey just win di Council for East and Central Africa Football Associations (Cecafa) challenge cup. ""If we bring dem here and line dem up, for those wey get flat chests, you fit mistake dem to be men - not women,"" she tok of female footballers. She say while some of di sportswomen don marry, most of dem never marry, ""and because of how dem be, life of marriage…na just dream [for female footballers]"". Di president say sportspeople dey normally live tough life afta dia career for sports don end and she come ask authorities to make sure say dem take care of athletes future afta retirement. But she come add join say na women dey suffer pass because ""dia legs go don tire, afta dem don retire from sports"". Dis don make pipo criticise wetin madam Suluhu tok. One Twitter user wey post part of President Samia speech yab her say: ""Dis na wetin di 'first female president' use mouth tok about oda women wey dey challenge stereotypes wit how dem dey play professional soccer!,"" tok Maria Tsehai. ""Wetin she tok no true!! She don generalize wit no scientific fact..."" hala anoda user Harry Mwala." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58273215 +entertainment Convicted Nigeria actor Baba Ijesha go know fate on bail "Di bail hearing for convicted Nigerian actor Olarewaju James A.K.A Baba Ijesha fail to hold on Monday. Di convicted actor bin ask court to grant am bail and release am from prison pending wen Appeal court go hear im bail application. Di bail hearing suppose come up for di Domestic and Sexual Violence Court Ikeja Lagos southwest Nigeria. Di actor make request to court about two months afta court sentence am to five years jail time say e defile a minor. Di court bin convict am on four out of a six-count charge wey dem sama against him by Lagos State Government. Oda charges against am na indecent treatment of a child, sexual assault and attempted sexual assault by penetration. Im lawyer Chukwudi Adiukwu come court to ask court to grant am suspended imprisonment till Court of Appeal go hear im case. Section 6 (6) of the 1999 Constitution, as amended tok say pesin fit get bail after conviction and sentencing if im appeal im case and judge rule to im favour. Di lawyer quote say section 51 of Administration of Criminal Justice Law, Lagos State 2015, empowers di court to admit di applicant to bail, either unconditionally or upon reasonable conditions. E argue say di cases done enta special circumstances status as di actor done apply for Appeal and im fit don serve im whole jail term before e go get date for hearing for Appeal court sake of say to get date dey hard. Omowunmi Bajulaiye-Bishi wey be di prosecutor argue say applicant fail to establish special circumstances inside di Administration of Criminal Justice Law of Lagos. Bajulaiye-Bishi tell di judge to reject di application and allow di actor serve his full jail term as court bin decide. Justice Taiwo bin adjourn ruling till September 19, 2022. Di presiding judge begin with summary of di arguments on Baba Ijesha case. Defence lawyer, Dada Awosika [SAN] and Prosecutor counsel, Prince A Olabiran and dia team for lawyers bin don dey argue di mata for months. Justice Oluwatoyin Taiwo say although di case don attract plenty media attention, di court must look for proves of di offence beyond reasonable doubt. Baba Ijesha dey face six count of sexual assault of one 15-year-old girl. Di charges include, indecent treatment of a child, sexual assault by penetration, attempted sexual. According to di prosecutor, Baba Ijesha bin don assault di girl seven years ago. Di goment lawyers argue say e happun wen she bin dey seven years old. Dat time di actor putg im car key inside her virgina, di prosecution counsel tell di court. Defence lawyer Prince Olabiran beg court to consider say di defendant Baba Ijesha na first offender. E also ask di court to consider di fact say di defender na actor wey don impqct seriously for society sake of im career. E add say di defendant get aged parents and im son wey still dey depend on am. E describe am a ""very changed pesin"".Olabiran ask court to consider di least sentence. Prosecutor counsel Martins want di court to decide how many years wey Baba Ijesha go get in total for all di four charges wey dem find am. Ikeja Sexual Offences Court pass di judgment on di case of molestation wey happun seven years ago against Baba Ijesha. Di court say e no fit conclude from di victime testimony say di offence happun without evidence. Di minor also tell di court say anoda neighbour bin molest her before. Justice Taiwo say, ""di most important tin be say penetration happun..""...but who or wen di penetration happun dey difficult to determine. ""Baba Ijesha admit say im touch di body of di minor for 2021 and molest her. But di actor deny say im no touch her at all seven years ago. Baba Ijesha, as part of in defence, say im bin go dey act script wit di minor. Di Nollywood actor admit to di court say im bin no know say CCTV camera bin dey inside di house on dat day. But di judge overrule, say di accused no dey act anything as no actor, no camera, no lighting or anything to show say dem dey act. Di defence present four witnesses while di prosecutor present seven witnesses. We don update dis tori." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c72w11lg7jro +politics Obasanjo, Charly boy video: 'I be di father of frustrated Nigerian youths' OBJ tell Areafada "Olusegun Obasanjo say im be di 'father of frustrated youths inside Nigeria.. Di former Nigerian president make dis claim during di visit of veteran entertainer, Charly Boy, to im residence on Friday. For di video wey Charly boy post for im instagram account, Obasanjo dish out advice to di 'frustrated Nigerian youths,' as papa wey e be to dem. Charly boy start by passionately introducing imsef as di president of di group saying; ""If as di president of frustrated youths of dis kontri, na me be dia president. Me myself I dey frustrated. Later on, Obasanjo come chook mouth for di conversation and ask Charly boy say; ""You be president of frustrated Nigerian youth?"" which e reply 'yes.' Den di former president come tell am say; ""Na me be di father of frustrated youths of Nigeria."" During di visit, wen Charley boy ask di former president to advise di ""frustrated Nigerians"" Obasanjo tok say, ""Dat we dey poor and frustrated no be di fault of God, na di choice of our leaders."" ""And if you want to change dat and change our situation, you gatz to change leadership. Pure and simple. ""And e no get anybody wey go do am except di youths."" Obasanjo come later describe Nigeria as im own baby wey e go like to put beautiful bead on her waist and no be for any individual body. E get about 109,810,327 pipo wey dey over age 18 inside Nigeria, according to one worldometer report. Na from 18 years and above dem dey reason say pesin don be youth inside di west African kontri. Dis number fit form half of Nigeria population wey dey projected at ova 200 million pipo, according to UNFPA. Also, according to di United Nations Population Fund (UNFPA) 54% of di kontri population dey between di age of 15-64. Wen e come to di average of a Nigerian citizen, di kontri dey relatively young. Na multiple ethnic groups dey Nigeria and di most common non-English language dem include language of Hausa, Yoruba, Igbo and Pidgin. Life expectancy inside Nigeria dey low in inside West Africa, data show. Di average life expectancy dey around 54.5 years of age according to WHO data, wit men living an average of 53.7 years and women living 55.4 years. Dis fit be unto say di kontri get a lot of health issues, public infrastructure palava,unemployment, inflation, and security challenges. Nigeria get di largest population in Africa. United Nations dey guess say di overall population of Nigeria go reach about 401.31 million by di end of di year 2050. Dis population growth no equal di level of development and cost of living in living. Meanwhile President Muhammadu Buhari confam say urgent need dey for a general salary review of Federal Public Service workers. Di Nigerian leader say di need to increase pay na due to worldwide problems of high inflation amidst general economic disruption. ""However, I wish to beg una to appreciate di revenue constraints wey Goment dey presently face caused mainly by di activities of jaguda pipo wey dey tiff our crude oil, a main contributor to our income base. ""Di mata even dey complicated sake of global economic downturn as a result of di on-going Russian - Ukrainian war, wey don lead to price increases... ""Not just di costs of goods and services globally, but also ontop transportation of dis goods and services across di world."" President Buhari tok. Di Nigerian leader reveal dis wen di Central Working Committee of Association of Senior Civil Servants of Nigeria visit am for di presidential palace inside Aso Rock on Friday, same day Charly Boy visit ex-president Olusegun Obasanjo. Charly Boy AKA Area-Fada na long time ogbonge Nigerian entertainer and activist. Him be di son of late Nigerian jurist Chukwudifu Oputa, di oga of Oputa panel wey sit for 1999 national conference Nigeria do. Oputa panel bin investigate human right abuses by former military juntas and submit dia findings in 2003. Area-Fada, as e dey call im sef, like to chook mouth for issues wey concern social justice and leadership in Nigeria. Close to di last election circle across Nigeria, Charly boy bin champion one movement dem call ""our mumu don do"". Dat movement dey similar to dis latest one wey e dey call imsef president of di frustrated Nigerian youths. And by di way, no existing group dey official named as such, but di entertainer fit don come up wit di idea sake of di way tins dey fail for Nigeria. Olusegun Obasanjo aka Baba OBJ (as many dey call am) don serve as Nigerian military and civilian leader. Di retired general served as Nigeria head of state from 1976 to 1979 and later as President from 1999 to 2007. Di 85 year old former leader dey known for im open-letters to sitting Nigerian presidents to address poor governance or challenging social issues. Dis no be di first time Obasanjo dey address leadership failure. E get time wen e hala say; Muhammadu Buhari no go dey good to handle Nigeria economy, as president. Only recently e cry out ova di cost of living in Nigeria wen e complain about di cost of diesel and how e dey affect im farm business. Chief Olusegun Obasanjo na respected personally across Africa. United Nations define 'youth' as those pesin between di ages of 15 and 24 years. But many kontries also draw di line on youth with regard to di age wey pesin fit get equal treatment under di law Often dem dey refer to am as di 'age of majority.' Dis age na commonly 18 years for many kontries. So once pesin reach dis age, he or she go dey considered to be adult. However, di operational definition of di term 'youth' different from kontri to kontri. E dey depending on relative sociocultural, institutional, economic and political factors." https://www.bbc.com/pidgin/tori-62616466 +entertainment BBNaija Lockdown Reunion 2021: Highlights from Dorathy, Brighto, Wathoni sexual affair for 'BBNaija reunion' "Tuesday episode of Big Brother lockdown reunion show reveal big wawu moments. Fans find out wetin di housemates do inside di house for Season 5 wey Laycon win. Di fourth episode focus on di love triangle between Wathoni, Dorathy and Brighto. Di show also focus on Ka3na and Praise relationship. And as usual since di reunion start di housemates no hide anything about dia feeling. Na so all of dem begin tok wetin dem do inside Biggie house wen dem stay for 70 days. See di highlights of Tuesday BBNaija Lockdown Reunion show. Wathoni explain to di host Ebuka Obi-Uchendu how she and Brighto take hook up. She also reveal how Dorathy enta di triangle. ""I hook up wit Brighto afta im kiss me for neck. ""I begin see am as my go to pesin for di house. Everybody bin get dia pesin."" Wathoni tok say: ""I tell Trikky say im fit no like me. ""But I no care becos I need to dey happy and I bin dey use am to make myself happy."" But di wawu moment na Wathoni revelation about Dorathy and Brighto sexual affair. Yes e happun inside di house but up till Tuesday night nobody know about. Wathoni tok raw to reveal say Dorathy and Brighto do serious sexual 'touch-touch'. For Dorathy, she speak on di reason why she enta di Brighto and Wathoni triangle She say na because she bin wan remove herself from di Ozo and Nengi situation. And at dat time Prince bin dey involved wit TBaj then. ""We start to dey close wen im ask me to paint im toes as im see me dey do oda pipo own."" She say na from dia she begin dey comfortable wit am. Den she continue to gist dem about her relationship wit BrightO. Na during di discussion she confam wetin Wathoni tok say: True-true Brighto and her do serious 'touch-touch' for di house. Her confession shock her fellow housemates. Dorathy wey carry second for season five say: Di tin wey pain her be say di next morning BrightO no check up on her. Brighto say him no talking to Dorathy di following morning afta dia serious 'touch-touch' for night na how im be. ""Wetin you want me to tell her?"" Him tok. Brighto comments shock im fellow housemates; Even Ebuka tell say him for at least say hi dat morning. him say dat no be how im be. Him still insist say im no bin want anything wit anybody for dat house. Im add say ""I no do anything wrong."" Na dia wey Wathoni agree wit Dorathy say him (BrightO) dey cold. Even though say na only two weeks wey Ka3na spend inside di house her activities during di show make her trend. One of di tins wey she trend for na her relationship wit fellow male house Praise. And di Boss lady dis time reveal more about di viral video wey show she and Praise. Di video show dem for bed, cover dia self wit bed sheet afta dem off light for night. For di first time she and Praise admit say dem do 'kerewa' inside di house. She add say dem also knack outside di house too. Tori be say before now di two of dem be dey claim say dem no do Kerewa. But dem call wetin happun dat night aggressive cuddling. For now fans go need find out more revelations about dia favourite housemates. More episodes still dey ground wey dem neva show." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57578238 +entertainment Tonto Dikeh post reveal Prince Kpokpogiri as she count her blessings on her new relationship status "Nigerian actor, Tonto Dike don officially confam say she dey in a relationship with Prince Kpokpogri. Dis don confam di tori wey bin dey fly up and down about her current relationship status. Di Nollywood actor tag Prince Kpokpogri inside social media post where she dey count her blessings and also refer to am as her 'husband'. She say ""I ADORE YOU @kpokpogri @kingandre_dikeh and all our kids. Thank you to MY HUSBAND."" For di video she post for her verified Instagram handle, e show her and Prince Kpokpogiri for di graduation ceremony of her son, King Andre, di son she get wit her ex-husband Churchill Olakunle. Madam Tonto write say God don answer one of her secret prayers as e give her man wey stand wit her as her head and as a father to her son. She thank God for her new status as she declare say if ""happiness na pesin, e for be her."" Tori of her new found love begin fly recently wen she celebrate di birthday of di man she claim say she dey in love wit, wit gigantic cake and plenty gifts. Although she no mention name and she no post any foto for di post. Plenty pipo bin congratulate her and say dem happy for her. Prince Kpokpogri too recently enta social media to unveil Tonto Dike and e say she dey blessed among women. Prince Kpokpogiri na Nigerian politician from Isoko, Delta state. Dem born am for 27th June 1978. Apart from say im be politician, e also be anti-corruption advocate. E bin come into limelight recently during im birthday for 27 June 2021 afta tori carry am say na im be di new man wey dey Tonto Dike life. From wetin we gada from im Instagram handle, Prince Kpokgiri na philanthropist as e recently share foto of school pupils im support wit scholarship. E also don receive plenty awards and recognitions wey include di Nigerian Silent Heroes Award, di Inspirational Leadership award from di Progressive Leader Association of Nigeria. Other awards wey e receive na Award as ambassador of peace and role model to Nigerian students wey di National Association of Nigerian Students, NANS give am for 2019. Tonto Dikeh na popular controversial Nigerian actor. She also be singer, songwriter and humanitarian. She be di owner of Tonto Dike Foundation. Dem born her for June 9, 1985 into a family of seven. She be di third child of Mr Sunday and Mrs Veronica Dike. Her mama die wen she be 3 years old. She grow up for Port Harcourt, Rivers state and she get Bachelor Degree for Petrochemical Engineering for Rivers state University of Science and Technology. Tonto begin act feem for 2006 afta she take part for one reality TV show, di Next Movie Star for 2005. Some of di latest feems wey she feature inside include Throne of War, Battle of the Queens, Terror of a Widow, Blackberry Babes Re-loaded, among others. She don try her hands for music and she release some singles like Sugar Rush wey she feature anoda Nigerian musician, Dbanj. She release Crazically Fit and she feature Terry G. she bin release oda singles join. Di actor don collect plenty awards wey include African Peace Ambassador Awards 2021 wey she post for her Insta story." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57880839 +entertainment 9ice wife: 9ice cheating video and wetin cause Nigerian Singer marriage kasala "Alexander Abolore Adegbola wey many pipo sabi as 9ice na ogbonge Nigerian musician wey do video to apologise to e wife. 9ice for inside di video say ""e don do terrible tin to e wife and e apologise for e wrong doing,"" as e no want to lose e marriage, wey be third one. Nobody know wetin really happun before di musician release dis video wey don go viral for social media. Dem born di Gongo Aso crooner for 17 January 1980 for Lagos state, South Southern part of Nigeria. Di 40 year grow up for polygamous home. Im papa marry five wives and get nine children. Na im be di only pikin of im mama and papa. 9ice na from Ogbomosho, one town for Oyo state, South Western art of Nigeria. E grow up for Bariga, Lagos state. He complete im primary school education for Abule Okuta primary school for Bariga. E later go CMS grammar school Bariga for im secondary school education. 9ice get admission to do Lagos State University (LASU) to study Law but e later drop out from di university to focus on im music career. E begin im music career for around 2000 but im don dey write im own songs since wen e be 14. 9ice don write many songs, release albums wey don win awards. 9ice gain popularity for 2008 wen he release one of im biggest hit single ""Gongo Aso"". Di song scata every area for Nigeria and make am win di award for di Best Hip Hop Artist of di year for di MTV Music Awards for 2008. Now im be di CEO OF Alapomeji Records and don release plenty songs under di record label. For 2014, 9ice show interest for politics say im wan run for election for im hometown, Ogbomosho, Oyo state. During di 2015 election, im join di All Progressives Congress Party and contest to represent im pipo for di Federal House of Representatives but im lose. 9ice bin work as Special Adviser to d late Oyo state govnor, Senator Abiola Ajimobi. Di award winning singer on Saturday post one video for im Instagram page dey beg fans to epp beg im wife afta one video of wia im dey touch one woman breast go viral. For di video wey one blogger share last week, e show as 9ice dey totori di woman and dey warn Yahoo boys make dem free her as na im get her. 9ice don marry three times. He first marry Toni Payne wen im career begin dey gada momentum for 2008. Di marriage scata on top accuse of cheating scandal. Dem get one son togeda. For 2018, e marry Adetola Anifalaje, one lady wey be software engineer for America. Di marriage dey blessed wit one daughter. Im current marriage na to im third wife Olasunkanmi Ajala Akande wey im dey tell im fans to beg to forgive am. Di singer release di apology wey im title ""Save a sinking vessel"" on Instagram on Saturday. ""I don do something wey dey shameful, sometin wey bad well-well wey dey cost me my family. Di most important thing to me right now na my family. Dat 9ice wey una see and like na because I get wife wey be my backbone. I apologise for wetin I do and I beg una to help me beg my wife. I don do well for so many things and one area I dey fail na for my marriage. I wan save dis marriage. I wan make dis marriage work, help me save my marriage for me. Sunkanmi please forgive me,'' di 40-year-old singer tok for di video wey don go viral. Plenty reactions don follow im apology video as some of im fans dey beg di wife to forgive am, others say im own too much." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55033522 +politics Wike go sign resolution to de-recognize Omehia as former Govnor "Di Rivers State House Assembly don pass motion not to recognise Celestine Omehia as former Govnor of Rivers State. Dis dey follow motion wey di leader of di House and Member representing Obio-Akpor Constituency 1, Martin Amaewhule pass. Amaewhule as e present di motion say di House no get copy of di ruling of di Supreme Court as at di time dem call for im recognition Amaewhule for di motion ask di house to cancel dia resolution of 30th June, 2015 wey bin direct di Rivers State Goment to recognize Sir. Celestine Omehia as former Govnor of Rivers State and restore im privileges and fringe benefits. Di Leader of the House note say to continue to recognise Celestine Omehia as former Governor and to continue to grant am privileges and entitlements wey dey due to former govnors of di State no dey in line with di 2008 Supreme Court  judgement for di case of Ameachi versus INEC and two odas, wey hold say for di eyes of di law, Omehia no ever be candidate for di election tok less of a winner and section 287 sub-section 1 of di constitution of di Federal Republic of Nigeria as amended. E come urge di house to direct  Celestine Omehia not to dey use di title ""His Excellency"" and di suffix ""Grand Service Star of Rivers State (GSSRS) wey only sitting govnors or former govnors of di state dey use. Amaewhule also present four prayers for di motion, including say make Omehia refund all money e don receive from di State goment since dem recognise am as Governor. Dis include N600million e receive as benefit and anoda N96.5million e don receive as pension as former govnor of di state within seven days.\n\nDi motion also include for am not be addressed as ""His Excellency, in addition to comot di title GSSRS from am wey di state dey take honour current and former govnors. Amaewhule also ask di Assembly to withdraw di resolution dem take on 30 June 2015 to recognise Sir Celestine Omehia as former govnor and restore om privileges and fringe benefits. For June 2015, Governor Wike bin recognise Omehia as former govnor of Rivers State becos im be function as govnor between 29 May 2007 and 25 October 2007 before e lost im seat after di Supreme Court declare Chibuike Amaechi as di right Governorship candidate of di PDP and so e replace Omehia as Governor. Wike come give order for di official portrait of Omehia to dey mounted among former governors of di state for Goment House. E say, “I, hereby, put back im [Omehia] official portrait among those of former governors. Im dey entitled to di benefits of all former govnors.” Wike bin add say di era of bitter politics don pass for di state as e wonder why Omehia, wey bin don discharged functions of govnor for about four months, go dey denied of im benefits as former govnor. After much debate, all 21 members wey bin dey present for plenary, vote in favour of di resolution, Di Speaker of di House, Ikuinyi-Owaji Ibani, come direct make di Clerk of di house forward di resolution to di state govnor, Nyesom Ezenwo Wike, and ask am to implement di decision sharp sharp. Oga Omehia never respond to di resolution wey di state lawmakers pass. Meanwhile, Govnor Wike, say e go sign di instrument on cancellation of di recognition of Sir Celestine Omehia as former govnor of Rivers State. For statement wey im media aide Kelvin Ebiri release on Thursday, di signing go take place for Goment House, Port Harcourt on Friday, 7 October, 2022 by 12noon. Sir Celestine Ngozichim Omehia (born 15 September 1959) bin be Govnor of Rivers State from 29 May to 25 October 2007. Im be member of di People's Democratic Party (PDP). E bin don serve as Rivers State Commissioner of Education between February 1992 and November 1993 and later get appointment as adviser to Governor Peter Odili. Omehia bin dey declared di winner of di Rivers State gubernatorial election of 2007, wey bin hold for 14 April 2007, despite plenti vote rigging and violence wey bin dey reported at di time. Dem swear am in as Governor of di oil-producing state on 29 May 2007, as e take over from Dr. Peter Odili, wey also be PDP Governor. However, di Supreme court comot am from office same year afta dem declare Rotimi Amaechi as di right Governorship candidate of di PDP." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c90g5xn1jgwo +entertainment BBNaija Nengi and Kaisha fight: Rebecca Hampson & Aisha Umaru fight fit affect fans vote for di Big Brother Naija housemates eviction show? Nengi and Kaisha fight na highlight of di BBNaija show on Saturday as fans chook mouth for di gbas-gbos wey happun between di two housemates. According to reports and from how di housemates take narrate di gist give each oda, Kaisha bin dey help Nengi check her kettle of water wey she plug and she feel say she no do am well. See Prince explanation of how di fight take start Nengi later approach am and di mata come lead to kasala and shouting match. Kaisha vex wen Nengi throw unpleasant words to am, e come make both of dem start dey throway insults at each oda. Normaly voting dey end by Thursday and dis fight happun on Saturday. However see as fans reactions be ontop di mata: https://www.bbc.com/pidgin/tori-53795181 +sports Afcon 2019: Indomitable Lions no satisfy wit bonus, but decide for go Egypt "Cameroon Indomitable Lions say though dey deh no bi satisfied for seka bonuses, deh decide for stop de problem go concentrate for dia competition for Egypt. Na since Thursday weh de Lions send 11 points for goment, why deh no wan take de bonuses, deny for travel as e bi for dia plan. Goment propose and don pay FCFA 20 million for dia account but deh bin ask for FCFA 40 million. For de discussion goment say e go add FCFA 5million but de players don deny for take de moni say e no near weti weh deh ask for. Deh give strong message for goment: ""We decide for go but we no want any meeting weh wen di play, not before, during or afta we reach Egypt"", de players write. Captain Choupo Moting and e kombi dem promise kontri pipo say deh go do dia best for make Cameroon football shine. ""We wan make some tins dem change and na de reason weh we take some stiff position. For generations de same problems di repeat but taim don reach for work laik professionals weh deh get for respect de sport pipo"". Lions dem thank kontri pipo for dia support di also share de sadness wit families weh dia pipo die for defend Cameroon. No bi de first taim Cameroon national team deny for travel for competition because of bonus. Samuel Eto'o and captain and e mates put plane for ground for seka bonuses for 2014 World Cup for Brazil. Cameroon as champions di go dia number 10 nations cup and go play for Group F wit Ghana, Benin and Guinea Bissau." https://www.bbc.com/pidgin/sport-48721375 +sports CHAN 2022: Expanded tournament don ready for unusual format Di Confederation of African Football (Caf) don announce say di 2022 finals of dia tournament for locally-based players go feature 18 teams instead of 16. Na Algeria go host di African Nations Championship (CHAN) in January, and e go get unusual format. Caf tok say di finals get five groups; three of dose groups go get four nations, while di oda two go get just three teams. E mean say di top two from di four-team groups go join di winners of di other two pools for quarter-finals. Di statement from Caf confirm say di regionally-based qualifying draw go shele on 26 May, but dem no announce di venue. Di Central (wey include Chad, Congo, FR Congo, Equatorial Guinea, Sao Tome and Principe) and Western A (wey include Cape Verde, Guinea-Bissau, Liberia, Mali, Mauritania, Senegal) zones go get both extra qualifying slot under di revised format. Morocco go take part in di Northern Zone qualifiers as dem bid to win di title for a third straight time, after dem defend am at di delayed 2020 finals wey shele for Cameroon last year. Di delay sake of di Covid-19 pandemic and di World Cup in Qatar for November and December dey get effect on di CHAN finals wey dem don schedule for 8-31 January 2023. https://www.bbc.com/pidgin/tori-61557826 +entertainment Meet Paul Okoye 'Pauloo' wey actress Iyabo Ojo reveal as her 'Obim' Plenty celebrities and fans don dey congratulate Nigerian actress Iyabo Ojo as she reveal di face of her lover wey she call ‘Obim’ wey mean ‘my heart’ for Igbo language to di public. Di Nollywood actress share video of her relationship wit Paul Okoye for her Instagram account as she celebrate her 45th birthday. She caption di video, “My Obim. Happy 45th birthday Iysexy. New age, new life, new wins. Cheers to forever #iypaulo.” Her lover, Paul Okoye wey pipo sabi as Pauloo also celebrate di Nollywood actress for im Instagram page. E describe her as ‘Ezenwanyi’, wey mean ‘Queen of all women’ for Igbo language. Although di two lovers neva tok wen dem begin date, however Iyabo Ojo bin don drop hint of new romance recently. Earlier for November, di actress, wey feature for di Real Housewives of Lagos reality show, bin hint at a possible relationship wit mystery lover on her Instagram page. She give am credit her glowing skin and happiness, say di Igbo man don capture her heart. She also confam to tori pipo say she dey inside relationship and go remarry. Di actress wey join di Actor’s Guild of Nigeria for 1998, say, “Yes, I dey  willing to give marriage a shot; yes, I dey in love. E get one Igbo man for corner wey don steal my heart away.” Paul Okoye wey many pipo sabi as Paulo na popular Nigerian Entertainment showbiz promoter. E be di Chief Executive Officer of Upfront and Personal Management, organization wey dey into films, music, sports and entertainment. E dey manage big talents for Nigeria and across Africa. Paulo na also di convener of di popular One Africa Music Fest, one annual event wey dey celebrate Afrobeats. He also dey promote shows for popular Nigerian singers. Iyabo Ojo na Nigerian actress, director, producer and brand influencer. Dem born her for December 21, 1977 for Lagos, Nigeria. She school for Lagos state and begin act professionally for 1998. Stok say na one of her senior colleague Bimbo Akintola introduce her to di feem industry and advise her to register wit di Actors Gild of Nigeria. She also help her build her career. Iyabo marry Ademidun Ojo, one clearing and forwarding agent wey dey work for Tincan Island, Lagos, for 1999, when she be 21-years-old. Although di marriage no last but e dey blessed wit two children. She divorce dia father for 2001. Iyabo say wetin cause her first marriage to break up na say she bin marry at early age. Iyabo na A-list Nollywood actress wey don act and produce plenty Nigerian movies. She bin recently feature for one TV Reality show, Real Lagos Housewives. Plenty colleagues and fans don hail di actress and don begin book place for di wedding on top her Instagram page. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw47y3p1ez2o +entertainment Big Brother Naija 2021: BBNaija season 6 launch - See wetin we know Di sixth season of Big Brother Naija reality show go start on Saturday 24 July afta audition for di new season end a couple of months ago. BBNaija na di biggest reality show for Africa, ova 49 kontries for di continent go tune in to watch di season launch wey go start by 7pm West African time, according to di show organizers. See interesting facts about di tear rubber BBNaija season 6 show. Dis season get two launch shows. Di first launch go happun on Saturday 24 July followed by di second on Sunday 25 July. Di two launch show go start by 7pm West African time. Organizers say dem don cancel all audiences for live shows and evictions, dem add say di presenter go host di Sunday Live Eviction Shows for empty studio, crossing live into di Big Brother House. Di reality show wey go last for 10 weeks go follow di lives of strangers as dem interact and compete wit each oda to win di grand prize of N90million worth of prizes, wey be di biggest reward for any reality show for di continent. Big Brother Naija season 6 go run 24/7 on DSTV Premium, Compact Plus, Compact, Confam and Yanga packages on channel 198 and on top GOtv Max and Jolli packages on channel 29. Ebuka Obi-Uchendu, wey be former housemate for Big Brother Nigeria show back in 2006 and host of di last four seasons of BBNaija - See Gobbe, Double Wahala, Pepper Dem and Lockdown - go return as di season host. Di top Nigerian TV presenter wey get plenti fans for social media not just for im MC work sabi totori pipo well-well wit im swag. Well na today we go meet some of di housemates for di launch show as Biggie neva reveal dia identity yet. But tori wey we dey hear be say dis season housemates hot well-well according to di organizers. Dem say dem say dis set of housemates go give fans of di show entertainment hot-hot. As per di theme of di season show na during di live launch show Ebuka, di show' host, go announce am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57952558 +sports Deontay Wilder: Di American blame im costume as why Tyson Fury defeat am "Deontay Wilder don blame im big costume wey im wear enta ring for why Tyson Fury defeat am for di WBC heavyweight title. Di American, 34, say im costume heavy so tey ""legs weak am"" for di fight. Fury from Britain use ogbonge fight to win di title for Las Vegas on Saturday after Wilder pipo ask say make referee end di match for seventh round. Wilder also tell US tori pipo say im go request for rematch to fight Fury for di third time. ""Fury no wound me at all, but di simple fact be say my uniform too heavy for me,"" Wilder told Yahoo. Wilder say di costume, wey dem sew plenty tins ontop am, also come wit mask and crown, weigh at least 18.1kg and na tribute to Black History Month. Fury on di oda hand no use im leg waka enta ring as im sidon ontop throne wey four pipo carri. ""My legs weak me from di from di beginning of di fight - and for di third round, my legs no fit carri me again ,"" tok Wilder. ""I no reason am say e go heavy like that."" Although dem carri Wilder go hospital after di fight, e say im no get concussion, say im ear drum no bust or im jaw break, like di way pipo dey tok." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51626407 +sports Mauro Icardi: Argentine striker don gbab permanent switch from Inter Milan to PSG "French champions Paris St-Germain don sign striker Mauro Icardi for 60m euros (£54m) from Inter Milan. Di 27-year-old Argentina international join PSG for September on one season-long loan with option of buy-out. Di new deal mean say im go dey di French side until June 2024. Icardi scored 20 goals for 31 matches for all competitions before di French season officially end for 30 April with 10 games remaining because of di coronavirus pandemic. Im bin don dey compete for a place for di side with Uruguay striker Edinson Cavani, wey be PSG's all-time top scorer, and im contract dey expire on 30 June. One statement from Inter tok say: ""FC Internazionale Milano announce di transfer of Mauro Icardi to Paris Saint-Germain FC: di striker, wey dem born for 1993, don permanently move to di French club. ""Di club dey thank di player for di six seasons wey im don spend with dem and wish am all di best for im future professional career.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52869813 +business Birds go replace Jammeh face ontop Gambia new money Di Gambia don release new currency notes wey get di national birds ontop, to take am replace foto of former President Yahya Jammeh. Central bank chief Bakary Jammeh present di money to President Adama Barrow before dem release am through commercial banks starting from Tuesday. Di money wey Di Gambia dey use na dalasi, wey don dey in circulation since independence for 1965. Di new notes na total change of all dia money including 5, 10, 20, 50, 100 and 200 notes. Gambia presidency ontop dia @Presidency_GMB announce di change on Monday. Na for 2015 dem print di money wey get oga Jammeh foto ontop and di central bank announce for 2018 say dem go begin commot am from circulation. Oga Jammeh rule end wen President Adama Barrow take office afta im win elections for December 2016. Di currency change dey happun for di time wen di Truth, Reconciliation and Reparations Commission (TRRC) wey di Gambia goment setup, dey investigate human rights violations wey dem allege happun during Oga Jammeh 22-year rule. Di mata include report of anyhow kill kill, torture and illegal detention. https://www.bbc.com/pidgin/tori-49238442 +entertainment Baba Suwe dead: Babatunde Omidina death, im son tok how veteran Nigerian comedian die "Nigerian comedian Babatunde Omidina popularly known as Baba Suwe don die. Im pikin Sola Omidina confirm Baba Suwe death to BBC Pidgin. Omidina also write for im instagram page say; ""Dis na to announce di sudden death of my father Mr Babatunde Omidina. Di legend and rare gem "" Babasuwe "" 11/22/21 Baba Suwe pikin say di Nigerian comedian die around afternoon on Monday. ""Dem reach out to me immediately e happun, but im (Baba Suwe) bin sick small"". Babatunde Omidina aka Baba Suwe bin dey 63-year-old before e die. Im son say e bin dey United States wen im hear di news of im papa death for Nigeria. Sola Omidina add say close relatives bin dey close to di comedian for im last moment. E describe e papa as a very wonderful pesin and good father. ""E be good father as e entertain di world, e entertain me as a son as well, because wen I dey watch am for screen, I no dey see am as my fada, I dey see as a comedian."" ""E dey funny on screen and funny off di screen. E be di best thing wey don happy to me."" Dem go announce Baba Suwe burial arrangement later, di son conclude. Rumors about di death of Baba Suwe don bin spread two times before; for 2019 and 2020. Baba Suwe na famous comedian for Nigeria film industry, Nollywood. E dey act for both English and Yoruba language films. E real name na Babatunde Omidina and dem born am August 22, 1958. Baba Suwe from Igbogbo for Ikorudo for Lagos mainland, inside Nigeria commercial capital. Di comedian do im primary education for Jamaitul Islamial Primary School inside Lagos and Children Boarding School, Osogbo. E later obtain im West African School Certificate from Ifeoluwa Grammar School inside Osogbo, Osun State capital, southwestern Nigeria. Baba Suwe begin acting for 1971 but become popular afta e featured for one movie titled, Omolasan. Di commedian become more popular afta e feature for Iru Esin, wey Olaiya Igwe produce for 1997. E dey act for both English and Yoruba language films and often dey play di role of confused servant or security guard. Di comic actor don feature and produced several Nigerian movies like; Baba Jaiye jaiye, one movie wey feature Funke Akindele and Femi Adebayo, di son of actor Adebayo Salami. For 2011, National Drug Law Enforcement Agency bin arrest Baba Suwe ontop suspicion of drug trafficking. Dis na afta one body scanner for Lagos airport identify suspected drugs for im stomach. Authorities bin stop am for di airport as e dey about to board one flight but dem later no see any drugs for e body. Afta more than three weeks Baba Suwe spend for detention, and 25 bowel movements, officials from NDLEA admit say e no excrete (poo-out) any drugs. Later dat year, one judge for High Court inside Lagos come give judgment make dem pay Babab Suwe more than $155,000 as compensation. Justice Yetunde Idowu say di detention of Baba Suwe na 'flagrant' abuse and infringement of e rights. E say NDLEA don fail to account for di nine days wey Baba Suwe dey for detention before dem ""rush"" to Federal High Court to get order to continue to detain am. Court also tell NDLEA to publish one public apology ""on conspicuous pages"" - dat is noticeable page dem for two national newspapers. Dat time, NDLEA Director of Public Prosecutions and Legal Services Femi Oloruntoba tok say di agency go appeal. E news of baba Suwe arrest and detention by NDLEA really shock fans welll before court judge say e dey innocent." https://www.bbc.com/pidgin/media-59378058 +entertainment BBNaija: Erica and Wathoni fight 'ontop Kiddwaya' as tears, strong words follow "For wetin wan be like daily tin, Erica don dey trend again, dis time afta one serious kwanta she get with Wathoni, wey latter end for tears for di former beauty pageant. E be like say di gbege start when Erica go meet Wathoni to try settle di mata of why Wathoni dey always dey rude to am. ""You dey always dey rude to me, why?... I come follow you tok about am, di next tin you mention Kiddwaya,"" Erica para. As Erica dey para, Wathoni sidon for chair dey look. ""Which one be ewo? 29-year-old, you get pikin, but your age no dey show for your behaviour,"" Erica bin hala ontop Wathoni head. All dis time di spark dey fly between di two women, Kiddwaya wey Erica claim say na di center of di wahala, bin just dey mind im business, dey cook food for kitchen. Later, Kiddwaya go meet Erica to pet her, he draw am close tell am say: ""I go always support you."" Di two of dem come comot, dey hold each oda hand, to assure everybody say dem still dey into each oda. Earlier, Kiddwaya bin don kiss Wathoni inside truth and dare game. Meanwhile, no be secret say Kiddwaya and Erica share close relationship wit each oda - as di two of dem don sleep on top di same bed and even kiss each oda many times. Erica one time declare Kiddwaya, di son of Nigerian billionaire as her 'special friend'. She even pick Kiddwaya to be her deputy Head of House. So dis kiss wey happun for di truth and dare game fit don spark di fire wey we see?" https://www.bbc.com/pidgin/tori-53762126 +sports Israel Adesanya vs Robert Whittaker 2 UFC 271 - Revenge or repeat of 2019? "Nigerian-New Zealand mixed martial art champion Israel Adesanya go face Australian Robert Whittaker again afta im beat am in October 6, 2019. Whittaker bin dey defend im middleweight title wen Adesanya knock am out for round two of di fight inside di Marvel Stadium, Melbourne, Australia. Afta Whittaker lose im title to Adesanya in 2019, im tok say di defeat carry am enta ""dark place"", and Adesanya don promise say e go take im opponent to ""di dark place again"" on Saturday night for Houston, Texas. Wetin go make dis fight dey tough be say Whittaker go won collect im title back and Adesanya go also won repeat wetin happun for 2019. For im pre-fight news conference , Adesanya tok say no be secret say im and Whittaker no like each other. ""No be secret say we no like each other. But I dey glad say im bin pull imself out of di dark place - say im dey feel much better and say im be better man and fighter,"" Adesanya tok. Whittaker tok say im don improve on im game and say di rematch go allow am test imself and how far im don improve. Adesanya dey trend for Nigerian Twitter space as im kontri men dey root for am ahead of di rematch. American mixed martial artist Kelvin Gastelum tok say no be everybody fit do wetin Adesanya dey do. Im bin face Adesanya in 2019 and e say e dey very surprised with im ability. ""Di way wey we take dig am, dat fifth round, no be many pipo for dis planet fit go dat kind dimension and survive. ""Physically, mentally and spiritually - no be many pipo fit do am. His (Adesanya's) grit and his ability to dig - I dey very surprised,"" Gastelum tell BBC Sport. Whittaker most recent fight na di one wey im win against Gastelum for last year April. Gastelum tok say im dey very surprised afta di fight. ""To be honest, I neva dey so impressed after a fight - I bin go back to di locker room scratching my head. ""E bin dey operate on another level and I never feel like dat before inside fight, even against Izzy (Adesanya),"" Gastelum tok. ""E just dey better dan me dat night. I never dey outmanoeuvred like dat - I never feel somebody who dey dat much faster.""" https://www.bbc.com/pidgin/60361158 +sports Tokyo Olympics: Nigerian federation 'bear responsibility' for ineligible athletes "Di Athletics Federation of Nigeria (AFN) don take responsibility after 10 athletes from di kontri bin dey declared ineligible for di Tokyo Olympics. Di Athletics Integrity Unit (AIU) bin rule say di competitors no go dey able to take part for Tokyo because dem no comply with out-of-competition drug testing requirements ahead of di Games. Di AIU announce say a total of 20 athletes from di seven kontris, wey include Morocco, Kenya and Ethiopia, regard as high risk (category A) wen e come to doping don dey ruled out, half of those wey dey excluded na Nigerians. Di AIU tok say: ""Nigeria na di most affected kontri, dem no meet di minimum testing requirements under Rule 15 for 10 athletes. Nigeria dey included for Category A for di start of 2020 following continued period of weak domestic testing levels."" Major blow Athletics account for 13 of di 25 medals wey Nigeria don win for all Olympic games, including two of di three gold medals, dis latest incident don cause serious outcry for di kontri. Officials of di AFN and sports ministry don come under intense criticism from some of di affected athletes, local media and fans wey no dey happy because dem bin don dey look forward to di track and field competition for Tokyo 2020 wey suppose start on Friday. But di AFN don try to calm di storm as dem take responsibility for di failings and put in place 'appropriate measures to comply wit Rule 15 of di Anti-Doping Rules of World Athletics'. ""Di AFN bear responsibility for any lapses wey fit don happun during di process and reassure Nigerians that our performances no go dey negatively impacted,"" di AFN tok for statement. ""All our athletes wey dey stay for Nigeria and wey qualify for di Olympic Games complete di three mandatory tests. ""Most of our top athletes wey dey stay USA also complete dia tests. However, a few athletes for di American collegiate system bin undergo test, but dem say those tests bin no follow WADA sample collection and analysis standards. ""We need note say no Nigerian athlete test positive to prohibited substances. ""Di AFN don take proactive steps to avoid make dis kind tin happun again in di future as we don appoint Professor Ken Anugweje as head of di Medical and Anti- Doping Commission of di Federation."" But 2008 Olympic long jump silver medalist, Blessing Okagbare, wey dey eligible for di 100 and 200 metres for Tokyo don shade di officials for dis latest setback. She don take to social media to express her disappointment: ""Di sport system in Nigeria get as e be and we athletes, dey always dey di receiving end of di damages. ""Dem bin dey busy dey fight over power, exercising their pride over puma contract/ kits as dem forget their major responsibility ""THE ATHLETES"". E dey sad say dis cycle dey repeat its self and some pipo go come out to say I dey arrogant for speaking my truth. Na my career."" Other athletes wey dey cleared to participate for Tokyo include, Ese Brume, wey win bronze medal for women's long jump for 2019 World Championships for Doha, Tobiloba Amusan wey dey ranked number four for di 100m hurdles and fast rising sprinter Divine Oduduru. One of di affected athlete na US-based Ruth Usoro, wey win di NCAA championship for di women's triple jump both indoor and outdoor for 2021. Usoro make di team Nigeria squad, but she and Rosemary Chukwuma, dey among di 10 ineligible athletes to participate because of non-compliance with out-of-competition drug testing requirements. Chukwuma coach Wes Kittley put di blame firmly on di AFN. ""Di bottom line na say Nigeria federation just drop di ball and no test those kids,"" im tok. ""Na terrible thing if dem no get to compete because di Nigerian federation no ever send anyone to test dem. Which go dey be unfortunate. My goodness.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-58011819 +entertainment Big Brother Naija 2021 audition date: How to pass audition for season 6 BBNaija registration requirements "How to win Big Brother Naija 2021 audition for season six wey be Nigeria biggest TV reality show dey many pipo mind now. DSTV Multichoice, di organizers of di yearly event recently call for audition for dis year housemates. Di organisers say di new season go get mouth watering N90 million worth of prizes for di winner, wey be five million higher from last year prize. Many of di past winners and housemates dey usually turn out to be big stars for Nigeria wit celebrity deals. Even as details of wen di new season go start never come out, BBNaija don already put date wey pipo fit begin audition for di show. Early audition go start from March 24 - March 31. So how to win di audition cross enta Big Brother house na im dey inside dis tori. Every past seasons of di BBNaija show get im own twist to di auditions but dis na wetin organisers dey usually expect from wetin we gather from di organisers website. To record two-minute video of yourself tok why you want make dem pick you to be Housemate of Big Brother Naija. After you record your video, then you go need to fill out di online registration form and upload your video. Dem expect you to answer all questions on di form fully and honestly. If dem later discover say you don deliberately lie or withhold some information wey dey relevant to your character or your past, dem go disqualify you from di selection process. If you apply to participate for Big Brother Naija, you allow di Producer to conduct civil, criminal, and any other type of background checks deemed necessary by di Producer. One of di Ex-Housemates, Timmy Sinclair AKA Trickytee wey don also write book about di tricks of how to win di audition share details wit us. For di selection process, you go prepare for possible video interview or physical depending on wetin di organisers decide at dat time. He also share hacks on wetin to do to get possible selection to become one of di housemates of di season 6 edition of di Big Brother Naija show. Stand out E say di first thing na to dey different from di crowd: expect say thousands of pipo go showface for di selection stage, so e dey important for you to dey different from di crowd. Trickytee say ""If you dey one room and everybody dey wear black and you dey out on white, you go stand out from everybody You no be di most handsome pesin or di most beautiful pesin or di most outspoken pesin , so you need to dey different for di panelist to notice you."" Self confidence na another thing im mention say e dey important. As an interested candidate, you must make sure to work on your self confidence before you face di panelist, he tok. Be Yourself: Dis fit sound like wetin you don hear many times but di former housemate say"" if you be Nigerian, no try to be American, If you be British, no try to be Nigerian, make sure to be yourself."" Who you really be, na im di panelist dey look out for. How you answer questions: From tips wey im share wit us, he say how you answer basic question need dey different. For example, im say when dem ask wetin be your name, no just say, my name na.... ""dat is basic"", he tok. ""Always make sure to answer in a unique way"" , di former housemate add am. E dey important to dey real for your video. Be yourself! and when you dey describe yourself remember to put real life examples. No Forget to share interesting things wey dey happun around you, wia you come from, di kind work you dey do and your background story. Make sure to hold camera your steady. If you dey shoot indoors, make sure to shoot wia light dey and in front of your face. Dem dey always advice pipo to shoot horizontal and not portrait style. Season Winner Prize Big Brother Nigeria 1 Katung Aduwak$100,000 Big Brother Naija 2Efe Ejeba N25,000,000 Big Brother Naija 3Miracle IgbokweN45,000,000 Big Brother Naija 4Mercy EkeN60,000,000 Big Brother Naija 5Olamilekan AgbelesheN85,000,000 We go still dey bring una more updates on wetin to do to stand a chance to win di Big brother Naija season 6 audition." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56539936 +entertainment Agbani Darego: Ishaya Danjuma and 2001 Miss World winner welcome second baby? "Reports for Nigeria don begin spread say former miss World, Agbani Darego and her husband Ishaya Danjuma don welcome dia second pikin. Di Nigerian beauty queen wey make history when she win Miss World for 2001, bin post message for her Instagram page on Friday 4 December, 2020 wit di caption ""thankful"". Like when she born her first pikin two years ago, di model no reveal di sex of di baby or even show e face for di post wey she make. Fans and friends don begin send her congratulatory messages for di news. Dis go be di 37-year-old model second pikin afta she marry Danjuma for 2017." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55199696 +sports Sancho: Man Utd say 'belle sweet' dem as dem agree £73m deal wit Borussia Dortmund "Manchester United say ""'belle dey sweet dem "" afta dem agree fee of 85m euros (£73m) wit Borussia Dortmund for Jadon Sancho. Man Utd announce di informate about Sancho transfer on Thursday July 1 2021. Di 21-year-old England winger dey expected to sign five-year contract wit di option of sixth year. Im go finalise terms and complete im medical afta England finish dia Euro 2020 campaign. Di money, wey dem go pay ova five equal instalments, go see Sancho become di second most expensive English player of all time behind Harry Maguire. Defender Maguire bin join United from Leicester for £80m for 2019. Manchester City go collect 15% of di profit wey Dortmund make on Sancho, wey join di Bundesliga club from di Blues for £10m four years ago. Dat na like £9.5m. United boss Ole Gunnar Solskjaer bin don identify four key positions im want to improve as dem dey look to build on dia progress last season. After e lead im side to second for Premier League and di Europa League final, di Norwegian dey look to strengthen di right side of im midfield, then di central defense, midfield and attacking areas. Sancho don fill di position. Sancho score 50 goals and register 57 assists for 137 appearances for Dortmund, and score twice for di German Cup final to help di Bundesliga side win RB Leipzig 4-1 for May. Im don win 20 caps for England since e make im international debut for 2018, and score three goals, and dem name am for di Bundesliga Team of di Season for 2018-19 and 2019-20. March 2000: Dem born am for Camberwell, south London, e grow up near Kennington. 2007: Watford spot am at di age of seven, dem register am as a player two years later. March 2015: E join Manchester City shortly before im 15th birthday for fee wey rise up to £500,000. August 2017: E leave City at di age of 17 without making any senior appearance, before e join Borussia Dortmund for about £10m. October 2017: Him dey part of England squad wey win di U17 World Cup, although na only di group stage im play before Dortmund recall am. E makes im Dortmund debut as late substitute for dia 2-2 draw for Eintracht Frankfurt. April 2018: E scores im first Dortmund goal for dia 4-0 win against Bayer Leverkusen a month afta im18th birthday. October 2018: E make im England debut at di age of 18 for dia Nations League draw wit Croatia, di first player born wey dem for 2000s to play for di Three Lions. September 2019: E scores im first England goals at di age of 19 for dia 5-3 win against Kosovo. February 2020: E become di only teenager to score 25 Bundesliga goals afta score di opening goal for dia 5-0 win over Union Berlin a month before im 20th birthday. June 2020: E finish di 2019-20 season wit 20 goals and 18 assists in 44 appearances for Dortmund in all competitions. May 2021: Afta im planned move to Old Trafford fall through in 2020, Sancho gada 16 goals and 20 assists across all competitions for di 2020-21 for Dortmund, wey see am make Gareth Southgate Euro 2020 squad. June 2021: United agree £73m deal wit Dortmund." https://www.bbc.com/pidgin/sport-57684153 +politics Oshiomhole: Kano court cancel suspension of APC Chairman Federal High court for Kano don cancel Abuja High Court decision to suspend Adams Oshiomhole as di national chairman of di ruling All Progressive Congress. Justice Lewis Allagoa order di Department of State Service (DSS) and police make dem provide Oshio Baba wit security wey im go take resume office. Justice Danlami Senchi of di federal High Court, Abuja, bin give court order on Wednesday say make political parties obey dia constitution and as Oshiomhole ward bin don suspend am, im no suppose dey function as di National Chairman of di party pending wen dem go hear di mata. Justice Senchi, fix di case for April 7 and 8, 2020. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51757503 +politics New Service Chiefs: Ibrahim Attahiru, Irabor, Gambo and Amao appointment by Buhari make Wike, Fayose, Dino Melaye to react - See wetin dem tok "Reactions still dey pour in for President Muhammadu appointment of new service chiefs. On Tuesday, di president accept di immediate resignation of di old Service Chiefs and approve dia retirement from service. President Buhari den appoint Leo Irabor as Chief of Defence Staff; Ibrahim Attahiru as Chief of Army Staff; Ishiaka Amao as Chief of Air Staff and Awwal Gambo as Chief of Naval Staff. Immediately afta dis appointment, Nigerians, politicians, Governors don react to di news of di new service chiefs. See dia reactions; Rivers state Governor, Nyesom Wike praise President Buhari for for di appointment of new Service Chiefs for di kontri. Governor Wike say even though di appointments come late, Nigerians need to commend di President for listening to di voice of di pipo. E say make di new service chiefs see dis appointments as opportunity to re-engineer di kortri security architecture wey don suffer serious setback for di last five years. "" Di new Service Chiefs should not politicise security by joining body with politicians. What di kontri need now na competence and professionalism wey go reduce insecurity well well. "" Wike tok. ""Dis na opportunity to serve di nation and I believe say di Service Chiefs go dey focus and dedicated. "" Former senator wey bin represent Kogi West senatorial district for upper chamber, Dino Melaye say make Nigerians no rejoice yet for dis new appointment. For im twitter page, oga Dino say make Nigerians dey observant; ""Dont shout Hallelujah or Alhamdulilaihi for di locomotive announcement of new service chiefs. Shine your eyes Nigerians."" Dino Melaye tok. Former Governor of Ekiti State, Peter Ayodele Fayose say President Buhari removal of di Service Chiefs and dia replacement na right step for di right direction, although dis dey come afta persistent pressure from Nigerians. ""Di sacked Service Chiefs only serve demselves and dia pockets and can at best be described as ""Disservice Chiefs"" and under dem, Nigeria become completely insecured."" Fayose tok ""I dey call on di ICC and oda relevant authorities make dem investigate di tenure of di ""sacked"" Service Chiefs , most importantly human rights abuses and extra judicial killings under dia watch and commands."" Fayose say make di new Service Chiefs learn from dia immediate predecessors and remember say nothing lasts forever. Igbo socio-cultural group, Ohanaeze Ndigbo particularly thank president Buhari for appointing Major General Lucky Irabor but add say di South East zone wey bin dey absent for first term still no dey included for dis reent appointment. ""We particularly thank Mr President for di appointment of Major General Lucky Irabor wey be tested General and a gentleman. However, Mr President, one way of ensuring compliance with federal character provision of di Nigeria constitution na to observe di distribution of important and vital offices of di Federal government in accordance with di zonal structure."" ""Mr president, particularly for di area of di security architecture of di kontri, di South East zone wey bin dey absent for your first term now still dey included now so far for your recent appointment of service chiefs."" Former aide to ex-president Goodluck Jonathan, pastor Reno Omokri no dey satiisfy with di pipo wey President Buhari appoint as di new service Chiefs. ""Wetin Igbo pipo do to President Buhari? "" Reno tok ""No Igbo heading di 3 arms of goment , No Igbo heading di 3 military branches, No Igbo heading any security agency.""" https://www.bbc.com/pidgin/media-55822286 +sports Croatia beat Japan on penalties to reach quarter-finals "Dominik Livakovic send Croatic into last 8\n\nCroatia beat Japan on penalties to qualify for di quarter-finals of di ongoing Fifa World Cup for Qatar.\n\nCroatia goalkeeper na di hero of di night, e save three penalties wey send Japan go house afta dem play 1-1 for full time.\n\nJapan first score thru Daizen Maeda for first half Croatia equalize for di second half thru Ivan Perisic.\n\nDi match drag enta extra time but nobody score.\nCroatia wey be di 2022 runners-up enta di last eight wit dia full chest. Penalties don reach o! 121+5 Croatia don qualify for di last 8! 121 min: Na Takumi Minamino go okay di first kick for Japan Japan miss!! goalkeeper save am! Croatia scores! Nikola Vlasic Japan Kaoru Mitoma miss second penalty Marcelo Brozovic score for Croatia! Takuma Asano score for Japan Mario Pasalic score Di last penalty for Croatia 120+1 Lovro Majer of Croatia bend di ball from di edge of di box wey disturb di goalkeeper but e play am go wide! 116 min: Borna Barisic(Croatia) collect yellow card afta e tackle Japan player. 113 min: Di ball dey behind di side line. Josip Juranovic take di throw-in 111 min: Shuichi Gonda jump to collect ball from corner but Mislav Orsic play am go over! 106 min: Anoda change, Ivan Perisic don comot and Mislav Orsic replace am 106 min: Japan and Croatia start second period of extra-time wit substitutions.\nAnte Budimir make way for Marko Livaja (Croatia)while Ao Tanaka replace Hidemasa Morita\n(Japan) First period of extra -time don end! 105 min: Save!\nKaoru Mitoma or Japan beat di pesin wey dey mark am as e fire beta shot from di edge of di box. Dominik Livakovic see di ball late but e stop am make e no enta net! 104 min: Borna Barisic send anoda cross again but Japan clear am again! 101 min: Ivan Perisic of Croatia fire shot but Japan defender block am 98 min: Substitution for Croatia \nLuka Modric don comot Lovro Majer replace am. Mateo Kovacic don comot too Nikola Vlasic enta 98 min: Josko Gvardiol of Croatia cross di ball into di box but Japan defence block am 95 min: Junya Ito of Japan dey try play fast fast wit di short corner kick. 92 min: Japan get corner kick wey Junya play but Croatia defence clear di ball 91 min: Extra time don start Dis na di first match wey dey enta extra-time for dis FIFA World Cup for Qatar. Second half don end, we wait for extra time to start 90+4 Di match go enta extra time as nobody win Four minutes added time 90+1’ Japan player commit foul referee blow whistle. Two minutes to stoppage time 90 min: Mateo Kovacic don collect yellow card 87 min: Substitution for Japan \nTakumi Minamino don replace Ritsu Doan 86 min: Miss!\nMario Pasalic of Croatia play im header wide! 82 min: Takuma Asano of Japan dey offside 82 min: Referee Ismail Elfath blow im whistle afta Wataru Endo of Japan play rough 78 min: Luka Modric play di corner for Croatia. 77 min: Ivan Perisic pass di ball from near outside of di box but e go wide off di left post 75 min: Substitution for Japan \nHiroki Sakai don enta field, e replace Daichi Kamada 73 min: Luka Modricgive short pass to im team mate from corner instead of im to play am inside di box. 69 min: Substitution for Croatia \nAndrej Kramaric don comot from di pitch, Mario Pasalic don enta. 64 min: Substitution for Japan\nYuto Nagamoto don comot and Kaoru Mitoma don replace am 63 min: Luka Modric strike di ball to di top left corner of goal, e raise im hand to celebrate but goalkeeper save di ball. Mateo Kovacic play di corner but notin come out 63 min: Croatia win corner kick. Luka Modric strike di ball to di top left corner of goal, e raise im hand to celebrate but goalkeeper save di ball. 62 min: Substitution \nCroatia don make dia first change. Bruno Petkovic don comot, Ante Budimir replace am 60 min: Yuto Nagamoto of Japan pass di ball to di net but Croatia defence clear di ball. 56 min: 1-1 Dejan Lovren na im give Ivan Perisic di ball, wey beat di defender for air as e play di ball inside di bottom right corner of di net from close range. 56 min: Goal! Croatia don score di equalizer! Ivan Perisic na im score di goal for Croatia. 54 min: Ritsu Doan of Japan wan play corner kick 49 min: Mateo Kovacic of Croatia fire shot near di goal post from di edge of di penalty box but e shot am wide! 46 min: Beta strike from Daichi Kamada of Japan near di edge of di box but goalkeeper manager push am ova di bar! 46 min: Referee Ismail Elfath don blow whistle to start di second-half First Half Di match between Japan and Croatia don start. 45+3 First-Half don end afta Luka Modric play corner kick. 45 min: VAR check di goal! confam! Japan dey celebrate!!! 44 min: Goal!\nDaizen Maeda score for Japan, afta Ritsu Doan take corner kick sharp sharp wit short pass. 40 min: Danger for Japan! Luka Modric cross di ball into di box from free kick but defense clear di danger. 38 min: Yuto Nagamoto of Japan try to create dangerous situation in front of di goal post , e send one cross into di Bo’s but defender clear di ball to goal kick for Croatia. 35 min: Yuto Nagamoto of Japan don commit foul as e dey try attack, referee blow whistle.\nJapan dey control di game wit short passes. 31 min: Daichi Kamala of Japan bin get space, but Croatia clear di ball. 29 min: Josip Juranovic of Croatia cross di ball inside di box but Japan clear di threat. 26 min: One long pass inside di box almost give Bruno Petkovic of Croatia good chance but e lose to one defender. 21min: Croatia player Josko Gvardiol fire shot wey go ova di bar afta e stand up from injury scare! 18 mins: Japan win free kick afta Josko Gvardiol of Croatia tackle dia player 16 min: Andrej Kramaric of Croatia swing in cross but one of di defenders clear di ball to safety. 10 min: Shuichi Gonda of Japan show im ability to read di game as e clear danger afta Bruno Petkovic of Croatia threaten to shoot ball from outside di box. 5 min: Croatia get possession of di ball as dem produce short passes from player to player. 3 min: A huge chance for Japan. Junya Ito play di corner short give Wataru Endo, wey immediately whips in a cross. E land give Shogo Taniguchi, six yards out, but di defender header goes wide. 2 min: Japan get free-kick on di left wing as Daizen Maed chop foul. Ritsu Doan whip am in but nobody fit reach di end. Dem get corner however. 1 min: Japan 000 Croatia Croatia attack within 10 seconds but dem don clear dia cross Japan and Croatia go put leg for one trouser today for di last 16 of di ongoing Fifa World Cup. Na for di Al Janoub stadium di match go shele, as di two kontri dey hustle to qualify for di quarter-finals. Japan defender Yuto Nagamoto tok say Japan must to ""fight like Samurai"" wen dem face Croatia in the World Cup round of 16. Japan shock Spain and Germany to win Group E as dem reach di knockout stage for a fourth time. Croatia, wey finish second for di 2018 edition for Russia na di obstacle wey dey block Japan as dem dey try to qualify for dia first World Cup quarter-final. Nagatomo add say ""di first condition na to get courage"" for di Al Janoub Stadium for Qatar. ""Before dem go into battle dem [Samurai] polish dia weapons and try to improve dia techniques,"" im tok. ""But if dem dey fear during di battle, dem no go fit use dia weapons and techniques well well. ""Na exactly di same wit football. Of course, di tactics and techniques dey important, but no mata how much wey we don improve, if we dey fear wen we dey for field, dos tins dey useless."" Croatia no score against Morocco and Belgium, but dia 4-1 win over Canada make sure say dem qualify as second for Group F. Oga of Croatia, Zlatko Dalic say im dey surprised about Japan 2-1 win over Spain and how dem no give up. ""Wen Spain score di opening goal, I bin tink say Japan don finish, but dem no give up dem and deserve dia victory. ""Di fact say Germany, Belgium and Denmark don comot just show how strong oda teams be for dis World Cup. ""If na before, I fit choose Japan as di opponent wey we go want to play, but dem don beat both Germany and Spain. For sure dis game no go esay for us”. Japan defender Ko Itakura dey suspended so Takehiro Tomiyasu fit replace am sake of say im don dey fit enough to start.  Im bin get hamstring injury for di beginning of di di tournament. However, Takefusa Kubo missed training on Saturday sake of muscular discomfort, while Hiroki Sakai still get thigh problem wey e get for dia match against Germany. Croatia oga Zlatko Dalic make just one change during dia three group stage matches,  and im fit stick stick wit di same team wey play against Canada and Belgium. Japan Gonda, Tomiyasu, Yoshid, Taniguchi, Ito, Endo, Morita, Nagatomo, Doan, Maeda, Kamada Croatia Livakovic, Juranovic, Lovren, Gvardiol, Barisic, Modric, Brozovic, Kovacic, Kramaric, Petkovic, Perisic" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cn0ylp95zpeo +health Coronavirus update: Former trader of fake Covid-19 test blame her condition, tok why she do am "Coronavirus don change di way wey we dey take travel and many kontris now need to see proof of negative Covid-19 test before dem allow pesin enter. But dis test no dey cheap. Wit how di pandemic don dabaru tins, e go dey even more tough for some pipo to comot that extra money to carry go do di test. Unfortunately, dis challenge don lead jaguda pipo to enter di illegal business of packaging fake results to sell give travellers. BBC tori pesin Joice Etutu follow two women talk – one wey dey sell di fake certificates, and anoda wey use am travel – and wetin make dem do am. UK-based Jessica admit say na social media she bin use take market fake certificates for pipo to buy. She say na “easy money”. ""Dem no wan pay £150 ($208) for private test,"" she tok. So ""we charge dem £50 ($69)"". ""Because e dey so cheap pipo ask many kwesions, like ‘how di tin dey work’, ‘how you take arrange am’, ‘I go enta wahala?’” Jessica reason am say she no get choice but to enta di magomago business because she be single parent. ""No one dey help me, no one dey give me money."" If I need to take small risk in oda to make like £300 ($416) to feed my pikin, trust me I go do am."" She say na when she sef wan travel but no get money for di test certificate she do fake one, and then after she enter di business hersef. In total she don do eight of dis kain result, but she say she don stop, because as pesin wey dey work for healthcare sector, her conscience no carry am say she dey put pipo live at risk. Anoda woman, Louise, wey bin use fake negative Covid-19 certificate travel go Ghana for October say na di high cost make her do di fraud. ""I just ask... 'who sabi use photoshop?' I ask my friends make I see dia Covid tests so I go know wetin di certificate look like and I tell pesin make e arrange am for me. Way just no dey to comot di money... and I know some pipo go dey reason am say 'so why I come dey travel?'” Like Jessica, Louise too sabi say na illegal tin she dey do but she admit say she go do am again. Until method dey ground to use computer check whether true true pesin do di test, she tok say she no reason why im go stress to do di right tin. Just on Monday, one federal committee wey dey manage Covid-19 mata for Nigeria announce say dem close down one fake test lab for capital city Abuja, wia dem dey package sell fake Covid-19 result. Dis illegal business dey put pipo life at risk because any passenger wey get Covid-19 - but no dey show symptoms - fit spread di virus to oda pipo. Goments across di world need to do more to torchlight dis problem. As one report by Foundation for Investigative Journalism (FIJ) reveal for Lagos, Nigeria, even goment workers for immigration, medical, port, fit dey work togeda to do dis bad business. Di ogbonge FIJ investigation wey comot on 9 February, expose say dem use money buy fake documents and bribe officials so as to travel go obodo oyinbo. Like Louise, na money fit dey make travellers chook hand inside something wey fit put dem for big trouble? So how much di test be? According to Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), na private labs dey do di test for di kontri and e cost anywhere between N36,000 ($95) to N50,400 ($132). For Ghana, pesin fit do di test for dia airports at di cost of $150. Jessica and Louise no be dia real names." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56011624 +sports Andre and Jordan Ayew: 'Ayew brothers still dey committed to Black Stars, dem no quit' - Spokesperson "Claims say Ayew brothers quit de Black Stars be false, dis be according to information from dia spokesperson. Reports wey start dey trickle in on Thursday suggest say de duo no go play give de Black Stars again. But according to Spokesperson, Fiifi Tackie, ""Andre den Jordan Ayew dey still remain committed to de Black Stars like before-before."" Inside post wey he share on Twitter, Mr Tackie explain say he talk get off de phone with them after news start dey spread say dem quit de national team. He talk say based on dia conversation, ""dem go continue to rep de Black Stars jersey den represent Ghana, give de team dia very best on den off de pitch, as always."" Spokesperson for de Ayew brothers clear de air on de wild claims wey start dey spread. De rumors say de brothers quit Black Stars receive mixed reactions from some who welcome de decision and others who feel say de Black Stars dey need de two strikers. Dis mixed reactions dey follow from de poor showing by de Black Stars during de AFCON2021 games where Ghana no fit proceed from de group stages. Some try blame de coach, others blame de Ayew brothers, fans blame GFA den tins. De Ghana Football Association (GFA) eventually sack Coach Milovan Rajevac over poor performance during de AFCON2021 tournament. Dede and Jordan Ayew be two sons of footballer, Abedi Ayew Pele who gain legendary status for Black Stars during en playing days. Both of en sons dey lead de striking force for de Ghana Black Stars. Both players move from de French League into de English Premiership where Dede Ayew play for Swansea City, whilst Jordan play for Crystal Palace. Dede Ayew however move from de EPL dey play for Qatari side Al Sadd." https://www.bbc.com/pidgin/tori-60158382 +sports EPL Fixtures: 5 tins wey go change when Premier League resume for June 17 "Millions of fans of Premier League football still dey happy ontop tori say one of di biggest leagues for di world go return on 17 June. But dem sabi say some tins no go be like how e dey before? So many tins don happun since 13 March wey dem suspend di Premier League because of coronavirus. One time, dem consider to cancel di season patapata. Small time afta dem reason am say make dem end di season as e dey, make everybody carry go house di position wey dem dey for table - like di way France take do dia league. But di clubs way dis idea no favour for bottom of di table para. But now clubs don sidon agree say make dem restart di season but wit conditions - some wey dem still dey torchlight. Make we see tins wey we sabi go change come 17 June. No be every player wey fans sabi fit return because clubs don agree say any player wey no feel say e safe to join team fit stay for house. Also, players go continue to dey do regular testing when season resume - like dem don dey do. And if any player or staff test positive, e fit affect di team because all di pipo wey dey close to am need to isolate. As di EPL resume na dis big clubs Manchester City vs Arsenal go start di action. Before na only on Monday, Saturday and Sunday dem dey play matches but as e be now, match fit happun on any day of di week. For di first time, BBC go carry live Premier League matches. Dis dey come as organisers dey reason how to make sure say more pipo fit watch. Premier League oga Richard Masters say ""E dey important to make say many pipo as possible fit watch matches for house."" Like how German league Bundesliga take do am when dem resume, Premier League fit consider to increase number of substitute players from 3 to 5. E don enta BBC Sport ear say na on Saturday, 25 July di 2019/2020 Premier League season go end." https://www.bbc.com/pidgin/sport-52817357 +entertainment Lola Omotayo-Okoye: Paul Okoye bash Peter Okoye wife Lola Omotayo wey call for P-Square' twins to reunite Lola Omotayo-Okoye di wife of Peter Okoye of di [P-Square] twins chop bashing and yabbings from Paul Okoye, one half of di Psquare music duo, afta she call for di twins to end dia beef and reunite. Lola bin make dis call inside di 'happy birthday' message wey she write give di twins for Instagram. Lola Omotayo-Okoye advise di singers say life dey short so make dem show love and respect to eachoda. Who be Jimoh Ibrahim? di Nigeria businessman wey billions of debt put for wahala Di top Nigerian identical twins Peter and Paul Okoye bin start dia music career for 2003 wit different bangers and plenti awards. But for September 2017, reports bin drop say di duo don go dia separate ways sake family kwanta. Lola birthday message no go down well wit Paul Okoye wey make am reply her wit very strong word. Im blast her say dem neva tok for four years but she dey always come wish am happy birthday for social media. Inside di long Instagram post, Paul write say im no go expose her or tok anytin because na family mata. Over di years, fans of di twins don beg Peter and Paul make dem settle and reunite but dat one neva happen till today. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55004573 +business 'I go export snake and dog meat to help di economy if I become president' - Kenya presidential candidate George Wajackoya tell im supporters during im campaign for Western Kenya for weekend say, if dem make am president, im go export snakes and dogs meat go China and oda kontris to take improve di kontri income. E also add say, im go make am legal to plant marijuana or igbo for di kontri so dem go fit to export am. Oga George dey among di only four pipo wey Kenya electoral commission give approval to run for 2022 presidential election. If e win election, e promise to create position for eight prime ministers and to suspend di kontri constitution for six months to allow pipo dictate wetin dem want to include for di document. Kenya grassroot presidential candidate George Wajackoya say im dey determined to fix di kontri economic challenges. George Luchiri Wajackoya na professor of law, kenya politician, and priest. E dey contest di election under di Roots Party of Kenya and na popular supporter for di use of medical marijuana Dem born am for Mumias but im grow up for Indangalasia village, West Wanga, for Kenya. At di age of 16 years, George for history of im life wey im write for Facebook say im run from home, from im village go di capital, Nairobi. E live for street until some pipo from Hare Krishna rescue am. Na from dia e kontinu im education. E join St. Peter Mumia Boys High School. Den later go different universities to get many different certificates. Wajackoya don work as human right activist and im don also lecture law and economics plus international relations for different universities for Kenya, US and UK. Di Kenya general election go happun dis year on 9 August, as President Uhuru Kenya dey end im two term in office. For dis election pipo go vote for di president, members of parliaments, senate, county govnors and members of di 47 county assemblies. Di Constitution of Kenya no get room for third term, diafore, President Uhuru Kenyatta no go fit contest for di 2022 election. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c25dx4vk8kno +politics William Ruto: Ruto beat Odinga to win Kenya presidential election "Kenya electoral commission don declare Deputy President Williams Ruto as di new elected president wey go lead di east African kontri for di next five years. Inside di final results wey di kontri wey Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC) chair, Wafula Chebukati announce, Ruto beat im main opponent Odinga wit 50.49 % of votes. Ruto win more dan half of di votes wey dem cast across di kontri. Four of di seven members of di electoral commission bin refuse to endorse di announcement, saying di results dey ""opaque"". ""We no fit take ownership ofdi result wey dem go announce sake o di opaque nature of dis last phase of di general election,"" tok Juliana Cherera, di vice-chairperson of Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC). ""We go give comprehensive statement... and again we urge Kenyans to keep calm. Open door dey wey pipo fit go to court and di rule of law go prevail,"" she tok. Oga Odinga's party agent earlier allege say ""irregularities"" and ""mismanagement"" dey for di election. Dis na di first time wey Oga Ruto, 55, go run for president. E don servedas deputy president for 10 years, but fall out wit President Uhuru Kenyatta, wey back Oga Odinga to succeed am. William Ruto go primary school barefoot, im wear in first shoes wen im dey 15 years. Im also sell chicken and groundnuts for roadside for villages around Rift Valley. So no be surprise say im dey show im sef as di champion of poor pipo during im presidential election campaigns. Dis na di 55 years old first attempt for presidency. Im dey hope say im go get di same luck wey im get for di first election wey make member of parliament Eldoret North constituency for 1997. E join politics for 1992, and say di then-President Daniel arap Moi n aim mentor. Ruto bin be part of di youth wing of Moi Kanu party wey bin be di main party some time ago, and bin dey among di activists wey dia work na to mobilise voters for di kontri first multiple election. Afta im hold different positions as minister - including education - im rise to become deputy president for 2013 election. Ruto contest dat election as di running mate of outgoing President Uhuru Kenyatta, and dis shock many Kenya pipo becos dem bin dey on opposite political sides for last election. Di two collabo bin be marriage of convenience, as di two bin dey face charge for di International Criminal Court (ICC) for crimes against humanity afta dem bin chop accuse for causing violence for di controversial 2007 election, wey lead to di death of 1,200 pipo. For di 2007 election, Ruto bin dey support opposition candidate Raila Odinga - wey be im presidential rival now - while Kenyatta bin back di den-President Mwai Kibaki for im re-election bid. Dia collabo wey dem bin call bromance, pay dem as di two enta power, and dis put dem for strong position to push away threat by ICC - sometin wey dem achieve wey make di prosecution drop di charges against President Kenyatta for 2014 and judges thruway di case against Ruto for 2016. But, dia collabo break for 2018, wen Kenyatta - pull anoda about turn stunt to reconcile wit Odinga, breaking Ruto hope say di outgoing president go endorse am as im successor for di current election campaign. Pipo close to di president accuse Ruto of disobedience, an allegation wey im deny. But im agree say im and di president ""see politics differently"". Loyalty to tribe dey very important for Kenya politics and Ruto from di third biggest ethnic group, wey dem dey call Kalenjin, wey don produce only one oda president, late Moi, wey be Kenya longest-serving ruler. Im marry Rachael, wey im first meet for church youth meetings. Dem get six children. Dia eldest son, Nick, bin once get di blessing of Kalenjin elders, and dis fuel rumour say dem de ready am for one political position, while dia daughter, June, dey work for foreign affairs ministry. Ruto like to farm and dat na why im dey into maize, diary and poultry farming. Im own big parcels of land for western and coastal Kenya and also invest for di hospitality industry. Ruto get link to corruption scandals for goment and pipo dey wonder about di source of im money. For June 2013, High Court order am to surrender 100-acre (40-hectare) farm, and make im compensate one farmer wey accuse am say im grab im land during di 2007 post-election violence. Im deny di accuse." https://www.bbc.com/pidgin/62552129 +politics PDP primary election Ondo State: Eyitayo Jegede, wetin we sabi about di main opposition candidate wey go challenge Gov. Akeredolu for Governorship elections 2020 Di 2020 Ondo governorship election go be anoda battle between Eyitayo Jegede(SAN) of di PDP and di APC sitting Governor Rotimi Akeredolu Jegede gbab di PDP ticket for di primary election wey dem do on Wednesday. Eyitayo bin contest for governorship seat for 2016 but im lose to Akeredolu. Eyitayo Jegede na Senior Advocate of Nigeria. Dem born am to di family of late Chief Johnson Bosede wey come from di Odopetu area of Akure, di capital of Ondo State. As im be ogbonge Lawyer, for 1992, Chief Justice of Nigeria appoint am as Notary Public and for di space of less than 10 years dem promote am to di rank of Senior Advocate of Nigeria. Im bin dey deeply and actively involved for political cases and election petition matters na im speciality. Afta twelve years wey im practise for law firm, six years wey im dey as Head of Chambers, he start im own law firm, Tayo Jegede & Co for 1996. For May 2009, di Ondo State, Olusegun Mimiko appoint am as number one law officer of di state, as di Hon. Attorney-General and Commissioner for Justice. Eyitayo emerge winner of PDP primary election to defeat di Deputy Governorship Candidate of di PDP, Hon. Saka Lawal for di 2012 governorship election. Im be one of di main opposition of Gov Rotimi Akeredolu for 2016 govnorship wit 150,380 votes against di 244,842 votes of Akeredolu. Eyitayo dey married to Madam Eno Jegede wey also be lawyer like am. For wetin im call 'My Offer' im plans na to Grow new state economy wey go dey majorly based on public-private partnership. Take advantage of plenti tourism centres for di state to also grow di economy. Also dedicate funds to support small and medium scale enterprises for di state. Provide free basic health care services to pregnant women and children wey dey under di age of 10. Eyitayo Jegede no be newcomer to contest govnorship election for Ondo State but di question na wetin go change dis year. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53510199 +entertainment Sia ft Burna Boy: Hey Boy by Sia Kate Isobelle Furler ft Damini Ogulu AKA Burna Boy - Di real gist "Sia, Australian born singer-songwriter, don announce new project wey she dey feature Burna Boy, Nigerian two time Grammy nominated star. For Twitter post wey she release on Tuesday, she announce say she dey drop di song Hey Boy wey go feature di Twice As Tall star on Thursday, 14 January. Tori be say she bin formerly release di same song for December last year and e go dey for her new album and movie, both of which she dey call ""Music"" wey dey drop for February. Burna Boy wey real name na Damini Ogulu sef don react to di news of di song say e dey definitely one of im favourites. Sia na Australian singer-songwriter wey don dey popular with di way she dey cover her face with wigs and sometimes dey hide for music video behind one dancer, Maddie Ziegler wey dey act as her younger self. Sia blow into limelight afta her song, Titanium with DJ David Guetta bin blow up for 2011 and she don tok plenti times about all di bad tins fame don do her mental health. For 2014, she introduce, di then 11 year old dancer Maddie Ziegler to play her alter ego, or di younger version of her as she dey promote her album ""1000 Forms of Fear"". Many more of her hit songs include, Chandelier and Cheap Thrills and she don write songs for artists dem like Beyonce and Rihanna. Sia wey real name be Kate Isobelle Furler, dem born her on 18 December 1975 and she be Australian singer, songwriter, voice actress and director. She start her career as a singer inside acid jazz band Crisp in di mid-1990s for Adelaide. Social media don dey burst or di tori of she and Burna Boy dia upcoming collabo. While some pipo dey hail di new collabo odas dey wish say she go sing with oda African artistes dem like Shatta Wale." https://www.bbc.com/pidgin/tori-55614845 +entertainment Wizkid made in Lagos: Ginger ft Burna Boy plus oda tins to know about Starboy latest album Nigerian Superstar, Wizkid don finally release di tracklist for im highly anticipated album, Made in Lagos. Di album wey di Starboy tok say go reveal im Nigerian sound go land afta almost three years since im bin first announce am. Dis go be Wizkid fourth album wey im go release afta Sounds from the Other Side wey drop for 2017. Di album go contain fourteen songs and get collabos from Nigerian celebs like Burna Boy, Tems, and Tay Iwar. E also collabo with some international stars like Damien Marley, H.E.R, Skepta, Prpojexx and Ella Mai. Di album art wey e sample for September 2020 no be di same one e dey launch di songs with. Di new album art na picture of Wizkid wey cover one side of im face with hand wey e wear ring wey get Nigerina flag. Di Starboy first announce say e go drop di album for October 1st, 2018 and den December of dat year, wen im do concert for Nigeria, Made In Lagos Festival but instead, e drop tow singles, Fever and Master Groove. On June, 2019, e comot with post about how Made In Lagos na one of di best album wey im don eva make but nobody don see am. For 25th September, Wizkid release Smile wey feature R&B star, H.E.R wey be single from di Made In Lagos wey im dedicate to im pikin dem. Im bin promise say e go drop di album, on October 15th but di date shift again on top di End Sars protests wey bin dey happun for dat time. Pipo for inside social media don dey anticipate di album as Wizkid say e go drop b 11:11 pm for Thursday. Di album don dey climb for di Apple chart list and e neva even comot yet https://www.bbc.com/pidgin/tori-54739843 +entertainment Kirk Franklin: Gospel artiste apologise afta Kerrion Franklin, im son expose audio recording wia e 'threaten' am "Gospel musician, Kirk Franklin don tok sorry afta im eldest son release one audio recording of 'physically threatening' argument im claim to get wit Franklin. Di 51 year old post di apology video on im Instagram page say many pipo know say for many years dem bin try to work to do therapy to rectify dia family quarrel. ""Many of una sabi my son Kerrion Franklin, im go be 33 years, for many years we bin get toxic relationship as a family. We bin try for many years to do counselling, to do therapy to try to rectify dis private family matter. But recently, my son and I bin get argument wey im choose to record, I feel extremely disrespected during di conversation and I bin loose my temper . I say words wey no dey appropriate and I dey sincerely sorry to all of una."", Kirk Franklin tok for di video. For di 45-second audio recording on di Instagram account of @kerrionrashad, we hear two voices dey get argument and dem dey shout at each oda. Although for inside di audio, e no dey clear who dey tok, but di caption for di post say audio na wit ""my dad"". For inside di audio, we hear one voice dey say im no wan ""disrespect"" and e say im go ""break your neck"" or ""put my foot for your a**—"" At di end of di recording, di younger voice say, ""He just hang up di phone. I go break your neck. dat na threat?"" To follow di recording, di @kerrionrashad post bin read in part: ""Dis na why I'm done. No father suppose speak to dia children like dis. If I have any issues na because of dis type of treatment that I dey deal wit behind closed doors."" Di @kerrionrashad post add, ""I no think I go ever trust my father to be alone around am ever again. I bin no wan do dis . I probably no go release di whole recording because e dey too embarrassing dat I dey even deal wit dis. No matter wetin pipo tink I pray my dad deal wit im deep hatred toward me. I no feel safe around am at all."" Kerri Franklin bin earlier share one post say ""2006 na di last time im dey allowed to take picture wit im family."" Kerrion Franklin, 33, na di eldest son of Gospel artist Kirk Franklin. Kerrion describe himself as an ""author, producer, and cinematographer"" on im Instagram profile. He also dey into music and dey always share pictures in a studio." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56398514 +health Coronavirus vaccines: African kontris wey don receive Covid-19 vaccine since e come out South Africa, Morocco, Seychelles, Mauritius and Egypt dey among di few African kontris wey don receive di coronavirus vaccine. Dis kontris no wait for di doses of di vaccines wey di African Union don secure for di continent as dem go ahead to make direct deal wit di manufacturers of these vaccines and some receive donation. Di African Union don secure additional 400 million doses of Oxford-AstraZeneca coronavirus vaccines for di continent, but dem no give any details about di cost. Dis one join together wit di doses wey di AU don already get for reserve and dos wey dem wan collect from di World Health Organization backed Covax scheme. Altogether, di vaccine wey di AU get don reach 1.27 billion but Africa need about 1.5 billion doses to immunize 60% of dia pipo. South Africa - Di kontri for di continent wey di pandemic hit well-well and wey dey battle one highly infectious new variant of di virus just receive di shipment of one million AstraZeneca vaccines from di Serum Institute of India. Dem go begin vaccinate dis first batch of vaccine afta e don undergo di necessary checks wey go take at least two weeks. Morocco - Don buy two million doses of di AstraZeneca vaccine and 500,000 doses of China Sinopharm vaccine. Dem go start dia vaccination campaign dis week. Seychelles - One popular tourist destination before di pandemic wey get population of 94,000, don already start free vaccination programme - thanks to di donation of 50,000 doses of Sinopharm dem receive from Abu Dhabi. Seychelles also tok say Indian government don also promise to give di island 100,000 doses of di Oxford Astra-Zeneca vaccine. Mauritius - another Indian Ocean island nation wey depend on tourism, don begin vaccinations dis week afta India donate 100,000 doses of the vaccines give dem. Egypt - wit a population of 100 million citizens on Sunday begin give out di Sinopharm vaccine. Dem start wit doctors and nurses. Di goment say dem don reserve more dan 100 million doses from different providers. Di oga patapata of di Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC) John Nkengasong, say most African kontris go get di vaccine and go begin roll out of mass vaccination programmes by March. He add join say bulk of di vaccine go arrive dis year and di rest for 2022. Nigeria - Di Presidential Taskforce on Covid-19 bin assure Nigerians say di kontri dey expect to receive 100,000 doses of di Pfizer-BioNTech Covid-19 vaccine by di end of January. But di vaccine neva still come as at now and di Chairman of Presidential Taskforce on Covid- 19, Boss Mustapha say no be dia fault e neva come. Dem neva tok di new date di vaccine go come. Meanwhile, di Nigeria Minister of Health Dr Osagie Ehanire say di Federal Government don release 10 billion to support domestic vaccine production. Di minister say di government dey explore di option of local production of di vaccines as dem don begin negotiate wit di producer. Di goment also say dem dey yarn wit China, Russia and oda pipo dem to get about 42 million doses of anoda different kind of Covid-19 vaccine. Ghana - President Nana Akufo-Addo say di kontri dey expect 17.6 million vaccine doses to arrive di kontri by di end of June. Malawi - Malawian President Lazarus Chakwera yarn say im kontri don secure di AstraZeneca vaccine and go begin vaccination month. He say Malawi go receive dia first vaccine supplies at di end of February. Meanwhile, for Tanzania, President John Magufuli don warn im officials make dem no collect any vaccines as di vaccine fit harm pipo, without evidence. Di kontri minister of health say dem no get plan to roll out Covid vaccines. https://www.bbc.com/pidgin/world-55923019 +politics Ghana Coup Update: All you need know about di coup and alleged plotters wey try to overthrow Prez Akufo-Addo "Ghana intensify efforts to prosecute alleged coup plotters wey plan to overthrow Prez Akufo-Addo. Attorney General of Ghana, Godfred Dame renew state efforts after dem rearrest, present de suspects before court wey dem slap fresh charge - high treason on dem. De new charge of High Treason be de highest crime of de land, punishable by death sentence for Ghana. All 10 suspects including senior police officer, ACP Benjamin Agordzo appear before de court on Saturday. De state dey accuse de high profile police officer, ACP Agordzo as alleged leader of de coup plotters who dey mobilize de activities of de group in WhatsApp. Attorney General, Godfred Dame reveal say ""dem plan to overthrow de President den later announce en overthrow. Dem manufacture explosives, test de weapons which show clear physical act to pursue de plan."" ""Dem discuss ways of killing de President, whether to kill de president or not... And how dem go make an announce en own overthrow"" Mr Dame reveal. In 2019, security agencies for Ghana arrest one group which called, Take Action Ghana who plan to overthrow govment. De security agencies mount dawn operation to arrest de suspects who plan in detail how dem go take over de country. Ghana security agencies according to Information Ministry, carry out joint operation for 15 months where dem survey den gada evidence on activities of de suspects. Some of de accused, Dr Frederick Yao Mac-Palm, Ezor Kafui and Bright Allan Debrah Ofosu according to security officials target young people to radicalize dem as part of dema plans. De accused who form group, Take Action Ghana (TAG) target key state installations like Jubilee House, Ghana Broadcasting Corporation, National Communications Authority as part of de coup plot. After de fresh charges, de court grant dema bail application pending next hearing on May 25, 2021." https://www.bbc.com/pidgin/media-56884890 +entertainment 'She dey well respected for her kindness'- Family of mother of two wey die afta crush for Asake concert "Di family of Rebecca Ikumelo wey injure and later die sake of crush wey happun for Asake Brixton 02 Academy show for London say di deceased na mother of two and nursing graduate wey love to work wit pikin dem. “She bin dey well respected for di family sake of her care, kindness and love,” di family tok for one statement wey dem release through di Met Police. “Her parents call her Tosin (short for Oluwatosin) wey mean say “Lord dey Worthy.” Tori be say di 33-year-old Rebecca from Newham, east London, sustain injury for di crush wey happun on Thursday afta some pipo wey no get ticket try force dia way inside di venue of di show. She die for hospital on Saturday morning, di Met tok. Two oda women aged 21 and 23 still dey for critical condition, police tok. Asake say im dey ""overwhelmed wit grief"" and ""devastated"" by her death. Di artiste say e don speak wit Rebecca family and ask pipo to keep dem for dia prayers. Academy Music Group, wey get di venue tok for one statement say wetin happun make dem sad. ""Everybody for O2 Academy Brixton and Academy Music Group dey deeply sad sake of di news of di tragic death of Rebecca Ikumelo. ""We send our heartfelt condolences to Rebecca family and friends, and our thoughts dey wit everyone wey dey affected by di devastating news for dis extremely difficult time."" London Mayor Sadiq Khan also write for one tweet say e dey ""heartbroken"" by di death. E say e dey important say make dem conclude investigation into wetin happun as soon as possible. Khan say City Hall dey work wit authorities to ensure say dis kind incident no happun again. Videos on social media show di crowd stretch from di road outside to di venue doors. As e dey tok for di scene on Friday, Ch Supt Colin Wingrove say: ""I go like extend my sympathies to all those wey bin dey affected. ""Afta I see some of di really upsetting images on social media our thoughts dey wit dem,"" im add. Di force say more than 4,000 pipo bin dey in attendance for di gig and dem set set up a website for pipo to submit relevant photos and videos. Di concert na di final performance of three sold-out shows for di venue by Nigerian singer Asake, wey dem sometimes sabi as Mr Money. Before di gig, im bin poste on Twitter dey ask im fans not to try to gain entry unless dem get dia tickets. Florence Eshalomi wey be Labour MP for Vauxhall wey her constituency include Brixton, tweet on Saturday: ""I visit di site dis morning and I bin don dey dreading dis news ever since di incident happun and bin dey hope e no go ever ever come to dis. ""My thoughts and prayers to Rebecca Ikumelo family and friends. Such a tragic loss of a young 33yr wit so much life ahead of her."" She tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c516ngdzd58o +entertainment BBNaija 2020 Eviction: Nengi, Praise, Dorathy, Ka3na and oda housemates wey fit comot from Big Brother show dis Sunday Some Big Brother Naija season 5 lockdown edition housemates fit comot from di house on Sunday , August 2. Dis week, 18 out of di 20 housemates dey up for eviction afta Biggie introduce new twist to di game. Voting don close for di housemates wey dey up for possible eviction dis week inside di Big Brother Naija Lockdown house. Na only di Head of house Lucy and her deputy Prince wey get immunity for di house. Di odas wey dey up for eviction na: Depending on wetin be di outcome of di votes na some of di housemates wey get di least vote go comot from di house. Every Sunday di housemates go take part for di live eviction. Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room. Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house. Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53627182 +politics Osun election: 50 lawyers readi to represent Oyetola for tribunal as Ademola Adeleke collect certificate of return "Govnor Gboyega Oyetola of Osun and di APC candidate fgor di July 16 govnorship candidate don ready to contest di result of di election wey see Ademola Adeleke of di PDP emerge winner. Kunle Adegoke, one Senior Advocate of Nigeria (SAN) na im reveal say di incumbent govnor of Osun State say 50 lawyers don indicate interest to join Gboyega Oyetola legal team to contest di electoral victory of Senator Ademola Adeleke for election tribunal. Adeleke of di Peoples Democratic Party (PDP) beat Oyetola and oda candidates during di govnorship election wey shele on July 16. Dis dey come as di Independent National Electoral Commission (INEC) dey present di Certificate of Return to di govnor-elect today. Adeleke score 403,371 to beat im closest rival Oyetola of di All Progressives Congress wey poll 375,027. Adegoke say dem dey carry di govnor-elect go court sake of say dem get authentic report of mismanagement of electoral process. ""We get authentic report wit report to mismanagement of di electoral process in a number of polling units, wards and local goments. ""And on dat basis we dey examine di document, listen to reports, collating dem togeda, we believe say valid ground dey to challenge di result of di election wey APC suppose win. So na why we dey go tribunal,"" di lawyer tok. Adegoke allege say both di Peoples Democratic Party and dia supporters engage in electoral malpractice. E say many lawyers indicate interest to join dem to battle di electoral victory for court sake of say dem see some irregularities during di election. ""So far we get 50 wey we don write dia names down but we neva know how many wey go follow us go court, dem fit be 50 and dem fit pass 50, dem fit also dey below 50 if we wan reduce di number,"" Adegoke tok. Adegoke say dem get more dan 70 lawyers wey represent former Osun Govnor Rauf Aregbesola of di APC in 2014/2015 for im case against Omisore. Di lawyers say di APC dey confident to win for di tribunal and e dey expected say di first court hearing go happun in di next few weeks. Di Independent national electoral commission (INEC) on Wednesday give di govnor-elect, Ademola Adeleke im certificate of retun as di winner of di election. Im deputy prince kola adewusi also collect im certificate for di event wey plenti pipo attend. Adeleke for im acceptance speech dedicate im victory to di memory of im late elder broda, Isiaka Adeleke wey be di first civilian govnor for di state. E say e go do evritin wey im promise during di electioneering campaign. For one interview wit tori pipo Channels TV after days after dem declare am winner, Adeleke say di current govnor never call to congratulate amd and say im still dey expect di call. However, President Muhammadu Buhari wy also dey di same party with Oyetola don send im own congratulatory message to Adeleke. Adeleke win 17 out of di 30 local goment areas of di state. Di election see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991. Na fifteen candidates bin dey di race to become di next govnor of di South Western state. Adeleke na di brother to di first executive govnor of Osun State Isiaka Adeleke wey lead di state between 1991 and 1992. Na Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC announce di winner of di election. According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast. Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di states of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election). Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions." https://www.bbc.com/pidgin/tori-62235065 +entertainment Will Smith banned from Oscars: Academy Awards banish Will Smith for 10 years over slap "Will Smith don dey ban from di Oscars gala and oda Academy events for 10 years. Di banishment of di US actor come afta e slap comedian Chris Rock for di Oscars. Academy of Motion Picture Arts and Science, wey dey organise di Oscars awards ceremony, meet virtually on Friday to discuss disciplinary action. Smith don bin apologise for im actions on 28 March 2022 and resign from di Academy days afta. Di actor hit Rock for joking about im wife shaved head, wey be as a result of hair-loss condition wey dem call alopecia. Less than one hour later, dem award am di best actor award for im role in ""King Richard"". Dat na feem wia e play di papa of tennis stars Venus and Serena Williams. For one statement, di Academy tok say di 94th Oscars don dey ""overshadow by di unacceptable and harmful behaviour wey we see Will Smith show on stage"". Di organisation tok say for di time di slap happen, dem no ""adequately address di situation for di room"" And dem ""no dey prepare for di incident wey happun suddenly"". Dem apologise for dis. Di Academy also thank Chris Rock for ""maintaining im composure under extraordinary circumstances"". Dem tok say di reason for banning Smith na to protect performers and guests and ""restore trust for di Academy"". For im resignation statement, Will Smith tok say e don ""betray di trust of di Academy"" and dey ""heartbroken"" over im actions. Smith add say e go ""fully accept any and all consequences for my conduct"". Di actor resignation mean say e go fit vote for future Oscars voters. Di Academy disciplinary review over di incident, originally dey scheduled for 18 April, but dem fast-track am afta Will Smith resign. Few pesin na im don resign from di academy. Four members - producer Harvey Weinstein, actor Bill Cosby, director Roman Polanski and cinematographer Adam Kimmel - don comot over sexual misconduct allegations. While dem expel actor Carmine Caridi for 2004 for pirating screener videos wey dem give am. But di standards of conduct wey di film academy lay out contain various disciplinary options for Smith. Like excluding Will Smith from future Oscars ceremonies, revoking im eligibility for awards or taking back di Oscar wey e newly win. Only one Oscar na im dem don ever take back; one feature wey dem call ""Young Americans"" bin win di best documentary honour for 1969 but dem find out say e dey ineligible for di award dat year. Late last month, actor Whoopi Goldberg - one member of di academy board of governor - predict say Will Smith go face ""big consequences"" but tok say ""we no go take dat Oscar away from am."" Aside di Academy actions, at least two studios - Sony and Netflix - dey pause dia projects with Will Smith. Chris Rock, wey begin im latest stand up comedy tour shortly afta di Oscars telecast, neva comment publicly on di slap. Rock tell fans for one show last month say e ""still dey kind of dey process wetin happun"" and go tok about di incident ""at some point""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61042895 +sports Croatia beat Morocco to win third-place for 2022 Fifa World Cup Croatia show dia class once more as dem gbab dia third top-three finish for di World Cup wit one play-off victory ova history-makers Morocco. Zlatko Dalic side be runners-up to France four years ago and confam dia status as one of di elite footballing kontris wit anoda third-place finish to go alongside wetin dem gbab for di competition debut for 1998. For one ogbonge opening, Josko Gvardiol give Croatia di lead on seven minutes wit one superb diving header but Achraf Dari level just two minutes later as dem nod home from close range. Mislav Orsic score a second for Croatia through di post three minutes before half-time and strike one ogbonge deflected drive into di side-net afta di break. Di second halfno match di energy of di thrilling opening period and Morocco fail to find an equaliser as dia fruitful campaign end in back-to-back defeats. Match don start! 2 mins: Luka Modric (Croatia) slide one pass forward, but one of di defenders cut am out. Na throw-in for Croatia. 3 mins: Lovro Majer (Croatia) swing in one cross from di corner, but Bono read am well and gada di ball. 7 mins: Goal! Josko Gvardiol (Croatia) beat di goalkeeper to score. 9 mins: Goal from Morocco Dem whip di ball in from di resulting set piece and find di head of Achraf Dari (Morocco) wey rise and produce one amazing header into di bottom right corner. 10 mins: Mislav Orsic (Croatia) find imself wit one great opportunity! Im unleashe a shot from di edge of di box, wey land for just di side of di post. Croatia 1-1 Morocco 16 mins: Dem clear di ball afta Marko Livaja (Croatia) attempt to dribble past one opposing player. Di ball dey out of play. Croatia win one corner kick. Luka Modric (Croatia) step up to take di corner, but di ball just sail in among di defenders. 19 mins: Sofiane Boufal (Morocco) clip one cross enta di penalty area but pose no threat. Di ball go out of play and Croatia go get a goal kick. 21 mins: Wonderful movement by Croatia. Di players dey hold possession, mostly dey exchange one-touch passes. Dem control di pace of di game as of now. 24 mins: Luka Modric (Croatia) blow one good opportunity. Im get a lot of space around am and e fire one decent low shot from di edge of di box towards di middle of di net, but di goalkeeper make a brilliant save and stop dis one! 26 mins: Dem penalise Yahya Attiat-Allah (Morocco) for holding. Abdulrahman Al Jassim signal one set piece. Croatia gba di free kick. 27 mins: Ivan Perisic (Croatia) plant one header from di edge of di box afta one nice cross from di free kick. E lack accuracy so di ball fly way ova di bar. 29 mins: Achraf Hakimi (Morocco) break past challenges inside di box, but im put too much pace on im pass to Youssef En Nesyri. 30 mins: Mislav Orsic (Croatia) find himself behind di opposition's defence, but refree stop di game for offside. 31 mins: Mislav Orsic (Croatia) fail to find any of im teammate across di pitch wit a long ball. Di ball dey off of di pitch and na goal kick for Morocco. 33 mins: Bilal El Khannous play one pass to Sofiane Boufal (Morocco), but im fail to get a decent shot away from inside di box and di ball go high ova di bar. Dat link-up down di right-hand side between Hakim Ziyech and Achraf Hakimi don dey so effective for Morocco throughout ditournament. No be surprise say dia best chances so far don come from di right side and dem dey have target dat side wit dia attacking play. 37 mins: Opportunity show face for Hakim Ziyech (Morocco) to deliver di ball into dibox from a corner. 37 mins: Hakim Ziyech send a lovely ball from di corner into di path of Youssef En Nesyri (Morocco), wey im close-range header flash just wide of di left post. Di ball dey off of di pitch and na goal kick for Croatia. 39 mins: Luka Modric (Croatia) produce one dangerous low pass into di penalty area, but di defence manage to cut am out. 40 mins: Hakim Ziyech (Morocco) showcase im fine individual ability as im beat a couple of players and hit a good long-range shot. Di keeper gazz scramble but di ball fly just past di right post. Di ball go out of play and Croatia go get a goal kick. 42 mins: Di total number of attempt na 6:3. 42 mins: Goal! Mislav Orsic (Croatia) manage to put di ball for di back of di net. Croatia 2-1 Morocco 45+1 mins: Extra time of minimum of 2 min. 45+2 mins: Hakim Ziyech (Morocco) send one long ball in, but Dominik Livakovic comfortably gada di ball. First half don end Second Half don start 46 mins: Walid Regragui make a switch. Ilias Chair dey come on in place of Abdelhamid Sabiri (Morocco) for di start of di second period. 47 mins: Ivan Perisic link up wit Mislav Orsic (Croatia), wey fire just wide of di left post from di edge of di box. 51 mins: Lovro Majer send one lofted pass into di box, Marko Livaja (Croatia) show good awareness to connect wit am but drag im shot well wide of di right post. Di ball don go off of di pitch and na goal kick for Morocco 54 mins: Plenti players dey wait inside di penalty area for a cross from di corner, but Luka Modric (Croatia) take di short. 56 mins: Bilal El Khannous dey go off and Walid Regragui give di last tactical orders to Azzedine Ounahi (Morocco). 57 mins: Abdulrahman Al Jassim no fit ignore di rough tackle by Jawad El Yamiq (Morocco) and blow im whistle. 59 mins: Yahya Attiat-Allah (Morocco) attempt to find di head of one of im teammates wit one promising cross into di box, but a defender outjumps di attackers and stop di threat. 61 mins: Hakim Ziyech (Morocco) swing in di corner, but dem comfortably clear am away. 63 mins: Lovro Majer (Croatia) attempt to pick out one free teammate inside di box, but Bono come off di line to clear di ball away. 64 mins: Di manager make a subsitution wit Anass Zaroury (Morocco) coming on for Sofiane Boufal. Dem also substitute Achraf Dari sake of injury. Walid Regragui send Badr Benoun (Morocco) on di pitch. 66 mins: Bruno Petkovic (Croatia) dey replace Marko Livaja as substitution. 69 mins: Caution to Azzedine Ounahi (Morocco). as e gbab yellow card. 70 mins: Ilias Chair (Morocco) send one lofted cross into di box wey dem head clear. 71 mins: Nikola Vlasic (Croatia) no get options but to fire one shot at goal from di edge of box, but na wasted effort and e go high ova di bar. 74 mins: Josko Gvardiol (Croatia) go down under one challenge for di box, but di ref immediately waves away di appeals from all players. 75 mins: Youssef En Nesyri (Morocco) think say im don score afta e react fastest to one lofted ball into di box, 76 mins: Here comes di ref decision afta di VAR review. No be penalty to Croatia as di referee indicate say infringement no dey! 80 mins: Hakim Ziyech (Morocco) attempt to find Ilias Chair, but im put far too much on di pass and di chance don go. 82 mins: Bruno Petkovic (Croatia) send one sweet pass into di penalty area, but one of di defenders stop di danger. Croatia force a corner. 83 mins: Mislav Orsic (Croatia) take di corner wey dem clear off. 84 mins: Selim Amallah (Morocco) pick up one yellow card say im tok out of turn to di referee. 88 mins: Anass Zaroury (Morocco) start im run too early and di referee blow for offside. 90 mins: Bruno Petkovic (Croatia) commit one minor foul to interrupt di attacking move of im opponent and idi refree warn aam say e go get yellow card if e do am again. 90 mins: Dem don add 6 extra minutes. 90+2 mins: Youssef En Nesyri (Morocco) fail to beat di offside trap and di linesman put im flag up. 90+4 mins Yahya Attiat-Allah (Morocco) send one teasing cross into di area, but Dominik Livakovic intercept di ball. 90+7 mins: Match don end Croatia 2-1 Morocco Croatia squad Goalkeepers: Dominik Livakovic, Ivica Ivusic, Ivo Grbic. Defenders: Domagoj Vida, Dejan Lovren, Borna Barisic, Josip Juranovic, Josko Gvardiol, Borna Sosa, Josip Stanisic, Martin Erlic, Josip Sutalo. Midfielders: Luka Modric, Mateo Kovacic, Marcelo Brozovic, Mario Pasalic, Nikola Vlasic, Lovro Majer, Kristijan Jakic, Luka Sucic. Forwards: Ivan Perisic, Andrej Kramaric, Bruno Petkovic, Mislav Orsic, Ante Budimir, Marko Livaja. Morocco squad Goalkeepers: Yassine Bounou, Munir El Kajoui, Ahmed Reda Tagnaouti Defenders: Anas Zniti, Achraf Hakimi, Noussair Mazraoui, Ganza Ek Niyssaiyu, Romain Saiss, Achraf Dari, Badr Benoun, Yahia Attiyat Allah, Jawad El Yamiq, Samy Mmaee Midfielders: Younes Belhanda, Sofyan Amrabat, Azzedine Ounahi, Abdelhamid Sabiri, Ilias Chair, Selim Amallah, Yahya Jabrane, Amine Harit Forwards:  Hakim Ziyech, Munir El Haddadi, Zakaria Aboukhlal, Ayoub El Kaabi, Soufiane Rahimi, Sofiane Boufal, Youssef En-Nesyri, Ryan Mmaee, Abde Ezzalzouli. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c7203ky8575o +sports Chelsea close to Aubameyang deal, Man Utd still dey push for Antony "Chelsea dey confident of sealing deal for Everton attacker Anthony Gordon, 21, dis week wit toks over di transfer of di England Under-21 international ongoing. (Times - subscription required) Manchester United dey set to complete di signing of Ajax forward Antony, 22, within next week, after dem reportedly agree personal terms wit di Brazil international. (Sun) Chelsea dey in advanced toks to sign Barcelona forward Pierre-Emerick Aubameyang, 33, for deal worth between £15m and £25m. (Sky Sports) Di Blues dey prepare to allow additional eight players comot for di transfer window afta West Ham agree deal to sign Italy defender Emerson Palmieri, 28. (Express) Officials from Manchester United dey set to travel to Barcelona in last effort to sign 25-year-old Dutch midfielder Frenkie de Jong before di transfer window close. (De Telegraaf via Mail) United also dey interested in Eintracht Frankfurtand Germany goalkeeper Kevin Trapp, 32. (Sky Sports via Football Daily) Watford say ""dem no go entertain any bids"" for Senegal forward Ismaila Sarr and dem dey ready to offer di 24-year-old new long-term contract afta im proposed move to Aston Villa fail. (Mirror) Di Hornets also no accept Newcastle United offer of £25m for Brazilian forward Joao Pedro. Di Magpies go need increase dia bid for di 20-year-old. (Telegraph) Tottenham dey interested in signing 24-year-old Leeds and Wales forward Daniel James. (Alan Nixon, via Leeds Live) Barcelona dey look at Celta Vigo's Spanish left-back Javi Galan, 27, as alternative to Chelsea defender Marcos Alonso sake of di Catalan club move for di 31-year-old Spain international dey get complicated. (Helena Condis Edo via Twitter) Wolves don agree personal terms wit VfB Stuttgart's Austrian striker Sasa Kalajdzic but negotiations between di two clubs remain ongoing for d 25-year-old as di Bundesliga side want higher transfer fee. (Mail)" https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp0qg4j41qno +entertainment Desmond Elliot: Why Nigerian lawmaker and nollywood actor name no gree comot youth dia mouth for social media "Nigerian lawmaker Desmond Elliot dey trend 'every time' for Nigeria social media space dis days as young pipo dey call am out anytime anything go wrong for di kontri and for mostly tins wey no concern di Lawmaker. With expressions like 'I blame Blame Desmond Elliot for this' , 'Na Desmond Elliot cause am' and so many others, di Nollywood actor and law maker wey dey represent di Surulere constituency for di Lagos State House of Assembly dey trend well-well. Desmond Elliot bin once post on im Facebook page in April, wia im acknowledge how pipo dey blame am for everything. E post picture wit di caption 'wetin dem tok say I do again?' as im wish Muslims a happy Ramadan and e end di post wit 'One love!' E no dey clear but wetin we know be say di whole 'Blame Desmond Elliot saga' start afta di ogbonge End Sars protest wey happun for Nigeria in October 2020. Desmond Elliot begin trend for social media on top di comment im make afta di shooting wey happun for Lekki toll gate, Lagos, Nigeria on Tuesday 20 September. For di house, im tok say ""make celebrities, social media influencers stop di hatred, una get constitutional power to change tins with your PVC and if you dey tired, enta goment."" E also say if Nigerians no dey careful with di way looting dey go on for di kontri, in five years we fit no get any kontri. Elliot bin praise di speaker of di house say e condemn di katakata wey happun for Lekki. E say, ""I like to thank di speaker on how e take condemn di carnage wey happun for Lekki. Wen I enta di comments section I no fit believe am, children dey curse upandan, dem enta Oba Palace tiff im staff of office. In di next five years we no go get any Nigeria if we no start now. ""Di youth no be only those wey dey do di peaceful process, those wey dey loot, wey don destroy lives, dem be youth too."" Howeva for anoda video, e clear di air say im bin no dey try to push any bill to control social media, say wetin e bin dey try tok na to tell social media influencers make dem no dey use dia platform to spread hate for di kontri. E say, ""I dey beg everyone say dis one no be true. No state house of assembly get di jurisdiction to pass any kain bill like dis."" But e no stop social media to bash di former actor; Even singer Davido call am out say ""e don spoil all di beta memories e give us as pikin with im feems"". While some tok say e no do well say, e call dem pikin, odas dey ask make di pipo of Surulere recall am for wetin e tok. One social media user, say Desmond Elliot show say di wahala no be to just get young pipo for goment because dem too fit dey clueless. Oda celebs sef follow cancel di lawmaker even as oda pipo dey ask pipo for Surulere make dem no vote am again for 2023. Di lawmaker later enta social media to apologise say: ""I don read your honest feedback and suggestion and I sincerely apologize for addressing di youth as ""children"". I no mean to dey insensitive wit dis, e dey borne out of di magnitude of destruction and looting of businesses wey I witness wen I go on a tour of my constituency. I see women cry and my constituent members sad as a result of di damages inflicted on dia source of livelihood. I dey moved by dis as I give my submission on di floor of di House. I bin allow my emotions get di better of me and for dis I apologize to everyone wey my earlier statements fit don hurt. "" E also ask pipo to understand say even di best of us make mistakes. ""Dis na why, moving forward, I ask say make we all try to engage constructively on di issues wey affect all of us. I promise to do the same."" he add am. But dis no stop pipo to dey consistently call out di lawmaker on social media. Recently, Nigerian actress Toyin Abraham bin weigh in on di mata for post wey she don later delete for Twitter, she say ""Please can we all stop wit dis Desmond Elliot joke. Please e dey actually annoying now. I feel if we continue wit dis joke then... kilode gan."" She later tok sorry wen pipo begin counter her tok." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56991817 +politics Meet di Pastors wey wan become Nigeria president in 2023 As di 2023 election dey draw near, anticipation levels don rise among political parties and di public because dem wan know who go be di kontri next president. Many popular Nigerians don join di race of di ruling All Progressives Congress party since election season start for late 2021. Some don withdraw from di race while opposition Peoples Democratic party primary election don already present dia candidate for di February 18 polls in former Vice President, Atiku Abubakar. Atiku running mate for di 2019 election, Peter Obi, na im be di flag bearer for opposition Labour Party. As e be so, na di All Progressives Congress party presidential primary election na im most Nigerians dey wait now. Out of di 23 pipo wey declare dia interest for di APC before di party say dem don cut am to 13 on Friday, three of dem na pastors wey dey run for di di race to be Nigeria next president. Dis one make many Nigerians to begin ask question wether dem go fit make any difference for governance in Nigeria sake of dia position for di religious space. Dis na sake of say religion be very important tin for Africa, and religious leaders get better seat for pipo mind for di continent. Even though Vice president Yemi Osinbajo be attorney for Nigeria, im be di Pastor in Charge of di Redeemed Christian Church of God Lagos Province 48 (Olive Tree provincial headquarters). But e no dey clear wether di professor of law still dey climb alter every Sunday to preach di gospel. Yemi Osinbajo na Nigerian lawyer, professor, and politician wey be di 14th and current Vice President of Nigeria since 2015 under di All Progressives Congress (APC). E serve as Attorney General of Lagos State from 1999 to 2007 and hold di title of Senior Advocate of Nigeria (SAN). For 1999, Osinbajo gbab appointment as Attorney-General and Commissioner for Justice for di cabinet of Lagos State Govnor Bola Tinubu. Afta e serve during both of Tinubu four-year terms, Osinbajo comot goment for 2007 and return to law. E follow dey do lecturing plus preaching for di Redeemed Christian Church of God. Before di 2015 presidential election, dem chose Osinbajo as running mate to APC nominee Muhammadu Buhari. Na dia ticket defeat di den-incumbent President Goodluck Jonathan and Vice President Namadi Sambo. Four years later, im win re-election. Dr Tunde Bakare na pastor and founder of The Latter Rain Assembly church. Na November 11, 1954 for Abeokuta, Ogun State dem born Pastor Bakare into Muslim Family. Pastor Bakare say im journey into Christianity begin for September 24, 1974. E start im ministry for May 1988 wia e pioneer di first Model parish of di Redeemed Christian Church of God. Pastor Bakare na qualified lawyer, e do im call to bar for 1981. Im practice law wit Gani Fawehinmi Chambers, Rotimi Williams & Co and Burke & Co, Solicitors. Before him establish im own law firm Tunde Bakare & Co (El-Shaddai Chambers) for October 1984. Pastor Bakare na minister wey like to torchlight national issues. Im political journey start for 2011 wen im become running mate to Muhammadu Buhari for di now-defunct Congress for Progressive Change. Nicholas Felix na 40-year-old Nigerian pastor wey base for di United states of America. Felix dey run for president seat under All Progressives congress party. Im be Former presidential candidate, Peoples Coalition Party (PCP), for di 2019 presidential election. For 2019, Felix bin come third di presidential election after President Muhammadu Buhari of di APC and Atiku Abubakar of PDP, wit 110,196 votes. According to di church website, e bin enta di United States afta im win di American Visa Lottery for 2004 and ten year later start di church. Dr Nicolas bin run im 2019 candidacy as say im be party wey dey find security. For interview, im tell tori pipo say e bin no comot Nigeria because e no get opportunities but because e no safe, so foreign investors no go come. Im church International Headquarters, dey New York, USA wit branches for New Jersey, Texas Atlanta and West Africa (Nigeria). For one tok tok wit tori pipo afta im declare im ambition ahead of 2023 election, Felix say im dream be to take over di helm of affairs for Nigeria and make change. E say im get companies for US and Nigeria and don hire thousands of pipo and say e dey quite comfortable by every standard. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz4wx0rp1v7o +sports Man Utd & Arsenal opponents for Europa League plus di full draw Manchester United go play La Liga side Real Sociedad while Arsenal go face former champions PSV Eindhoven for Europa League group stage. Erik ten Hag side go also play FC Sheriff and Omonia Nicosia for Group. Arsenal dey di same draw wit Bodo/Glimt and FC Zurich for Group A. Di Europa Conference League winners Roma dey Group C wit Real Betis, Ludogorets and HJK. Group A: Arsenal, PSV Eindhoven, Bodo/Glimt, FC Zurich Group B: Dynamo Kyiv, Rennes, Fenerbahce, AEK Larnaca Group C: Roma, Ludogorets, Real Betis, HJK Helsinki Group D: Braga, Malmo, Union Berlin, Union Saint-Gilloise Group E: Manchester United, Real Sociedad, FC Sheriff, Omonia Nicosia Group F: Lazio, Feyenoord, FC Midtjylland, SK Sturm Graz Group G: Olympiakos, Qarabag, Freiburg, Nantes Group H: Red Star Belgrade, Monaco, Ferencvaros TC, Trabzonspor Manchester United, wey bin win di tournament for 2017, dem bin play Real Sociedad for group stage of di Champions League for 2013. FC Sheriff na di Moldovan champions while Omonia Nicosia, from Cyprus, na former Celtic boss Neil Lennon be dia manager. All three of Arsenal group-stage rivals bin dropped out of di Champions League qualifying phase. Group stage Matchday 1: 8 September 2022 Matchday 2: 15 September 2022 Matchday 3: 6 October 2022 Matchday 4: 13 October 2022 Matchday 5: 27 October 2022 Matchday 6: 3 November 2022 Knockout phase dates Knockout round play-offs: 16 & 23 February Round of 16: 9 & 16 March 2023 Quarter-finals: 13 & 20 April 2023 Semi-finals: 11 & 18 May 2023 Final: 31 May 2023 https://www.bbc.com/pidgin/articles/c98jq2nv0yjo +politics Edo State House of Assembly Speaker: How APC take inaugurate members into 8th House of Assembly Di latest from di Edo State parliament drama for Nigeria na say e be like di two speakers don emerge for di House of Assembly. Di gbege gada ginger on Thursday morning when Govnor Godwin Obaseki on Thursday order and remove di roof of Edo State House of Assembly make nobodi do sitting afta di govnor kwanta wit police team wey attempt to take over di Chief Anthony Enahoro Complex. All dis dey come ahead of di 19 September, 2020 Governorship election for di state. Nigeria presido Muhammadu Buhari don edorse Osagie Ize-Iyamu as All Progressives Party candidate. See di video of di inauguration of one faction of di 24-member assembly wey happun on Thursday. Meanwhile Govnor Godwin Obaseki on Friday explain how di current Edo House State House of Assembly crisis wey lead to declaring 14 lawmakers seat vacant afta 180 days as e follow for di whol political crisis ahead of di 19 September, 2020 election. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53675756 +entertainment BBNaija nomination for eviction today: Yerins, Beatrice, Whitemoney, Yousef and Niyi all dey up for possible eviction on Sunday Di 'Shine Ya Eye' housemates of di Big Brother Naija reality show don nominate pipo wey dem want make viewers evict on Sunday. Beatrice, Yerins, Jaypaul, Niyi and Whitemoney dey up for eviction but Head of house save Jaypaul and replace am with Yousef. Sake of di decision of di head of house, Boma, housemates wey come dey up for eviction na: Beatrice, Yerins, Yousef, Niyi and Whitemoney. Di nomination take place on Monday evening afta di Head of house challenge wey Boma win. Ebuka wey be di host of di show say di wildcards get power to nominate four housemates each for possible eviction. According to di rules of di show, nominated housemates no dey permitted to campaign or solicit for votes. Maria: Maria wey be wildcard na di first to go inside di diary room for nomination. Afta some delay and confusion she nominate Beatrice, Yerins, Jaypaul and WhiteMoney. Pere: Second to enta di diary room na Pere wey also wildcard and e nominate Beatrice, Yerins, Niyi and Whitemoney Boma become di new Head of House for di ongoing 2021 Big Brother Naija reality TV show, wey dem tag 'Shine Ya Eye'. Im pick Jackie B as e deputy but she no go get any immunity unlike before. E win di special position afta e defeat oda contestants wey bin also do di HoH challenge. Di game to determine dis week Head of House bin involve dia usual tossing of dice like dem bin do for week one Afta every body play, Boma na im get di highest point. As Head of House, im go dey immune from eviction and go also get access to di HoH bedroom togeda wit im deputy, Jackie B. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58060085 +sports Premier League prediction for dis weekend matches Di Premier League go return dis weekend afta di international break. All eye go dey on di two derby match dem for London and Manchester. Di two fixtures get a lot of history and big rivalry. Na Arsenal go open di Premier show dis weekend wen dem host Tottenham Di Premier League leaders go play di game for Emirates Stadium. BBC football expert Chris Sutton go predict di outcomes of di fixtures for dis weekend. Sutton along wit Sports Team drummer Al Greenwood, wey be Manchester United fan go share im prediction too.. Checkout dia prediction. Arsenal start di season so well, dem don win six out of seven league games. Dia only defeat come for Manchester United, and dem no deserve to lose dia. Meanwhile Tottenham dey only one point behind dem. You fit make case for either team here, but my mind dey go wit Arsenal - and for dis game I dey plenty goals. Sutton prediction: 3-2 Al prediction: Arsenal go dey hope to repeat dia women performance against Spurs last weekend - and di result as well. I dey back Mikel Arteta side to win too, because although Tottenham also dey well, dia performances no always dey matched dia results. 2-1 Bournemouth fans dey para for me because  I dey write them off every week, and now dem dey unbeaten in dia past three games. Meanwhile Brentford bin dey disappointing against Arsenal for dia last game, but I feel say dem go respond here. Sutton prediction: 0-1 Al's prediction: Dis one dey very difficult to call, I chang my mind a few times - but I feel say Bournemouth go get something. 1-1 I no really know wetin to expect from Chelsea hia, and whether anything go click at all or change dramatically for Graham Potter first league game in charge. Crystal Palace go make tins difficult for them but I feel say we go see improvement from di Blues, and e fit dey enough for victory. Sutton prediction: 1-2 Al prediction: Palace dey hard to break down, but dem no really offer enough threat for di oda end. E look like say Graham Potter don make a big difference for Chelsea already and with di boost e don give di players, I go back here. 1-3 Newcastle no really dey good form, na only once dem don win dis season. So, I dey go for a draw here. Being honest, Fulham don surprise me wit di way dem start dis season so well. Dem clearly believe in di way dey play. Sutton prediction: 1-1 Al prediction: Aleksandar Mitrovic dey fine form dis season and I feel say im go score a couple more goals against im old team. 2-1 Brighton bin get good record here under Potter, wit one draw and one win for dia past two visits. But dis na di first time wey go see dem under dia new boss Roberto De Zerbi. Sutton prediction: 3-1 Al prediction: Liverpool form get as e be so far, but we no really know what to expect from Brighton under De Zerbi. E go dey interesting how dem go be. 1-1 I no really know wetin to tok about of Southampton. Sometimes dem dey play wit blood and thunder under Ralph Hasenhuttl, but oda dem no dey to attack very much at all. Everton don improve but, just like Newcastle dem be draw specialists for Premier League dis season, and I  dey see dem share di points. Sutton prediction: 1-1 Al prediction: I can see why dis two teams dey di bottom half of di table – dem dey so inconsistent. 1-0 Diego Costa fit make im Wolves debut here, but I feel say we need to dey realistic about what to expect from him. Dis no be di Costa we see for Chelsea, for di peak of im powers. Now at 33 e neva play a competitive game dis year. West Ham too dey struggle, but I feel say dem deserve more points than wetin dem get. Sutton prediction: 1-0 Al prediction: Both teams don only score three times apiece for dia first seven league games, so we no go see many goals for dis one! 0-1 For all di positive about Manchester United progress under Erik ten Hag, dem dey play Manchester City - wey be di best team for di kontri and by far di best team for Manchester. United fit cause dem problems for counter, but dem go dey really gingered for dis game. Sutton prediction: 4-1 Al prediction: We don beat City for Etihad Stadium a few times in the past couple of years, wey suggest say we get chance this time - but going there dey make my heart beat. So I dey go for a highly optimistic victory. 1-2 Leeds boss Jesse Marsch no go dey bench aft aim chop red card against Brentford last month. Him side go still play wit di same great intensity though, and Elland Road always seems to lift them. Villa big win ova Southampton last time, but their results on for road so far dey been poor, wi three defeats out of three, and I don't see that changing here. Sutton prediction: 2-1 Al prediction: Dis fit be a really good game. Leeds always turn up whether good or bad, there is always something happening. Villa will sit back more, but if Leeds score early e fit really be open game. 3-2 Dis na di bottom two teams and really anything fit happen here. E dey hard to suppport either side to win it, because we know dis flaws. Sutton prediction: 2-1 Al prediction: We know say Leicester na good team but they have been really poor so far. Sometimes it takes a derby game like this to kickstart your season. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4n01zd7k8do +sports Nigeria vs Lesotho result: Victor Osimhen, Etebo Oghenekaro, Paul Onuachu goals give Super Eagles 3-0 victory against Lesotho Nigeria complete di qualification phase for di 2021 Afcon wit unbeaten record afta dem defeat Lesotho 3-0 on Tuesday. Napoli striker Victor Osimhen na im open di scoring for di 23rd minute as di Super Eagles mark dia return to playing in Lagos wit victory over di crocodiles of Lesotho. Midfielder Oghenekaro Etebo goal for di 50th minute through Victor Osimhen assist put di Eagles for cruise control of di match early for di second half. Substitute Paul Onuachu come seal di three points for match wey 30% of fans witness inside di Teslim Balogun stadium. Dis na Onuachu second goal in two matches following di one wey im score for Nigeria against Benin Republic last Friday. Victory over Lesotho ensure say di Super Eagles finish di qualification round for di 2021 Afcon wit unbeaten record. Nigeria also finish as winners of Group L wit 14 points as dem record four wins and two draws. For Lesotho, dis defeat confam say na dem go finish bottom of di group. Cameroon na dem go host di 33rd edition of di continent football showpiece afta Confederation of African Football postpone am earlier due to Covid-19. https://www.bbc.com/pidgin/sport-56583657 +health Covid-19: Omicron dey spread fast fast - French PM "Di Omicron variant dey ""spread at lightning speed"" for Europe and go dey likely to become dominant for France by di start of next year, French Prime Minister Jean Castex don warn. E tok on Friday, hours before France impose strict travel restrictions on those wey dey enter from di United Kingdom. UK so far be di hardest hit for di region, with nearly 15,000 confamed Omicron cases on Friday. Across di continent, health officials dey ready for a wave of infections. Authorities announce additional restrictions for Germany, the Republic of Ireland and the Netherlands on Friday as goments dey chook eye on how to tackle am. Europe don already record more dan 89 million cases and 1.5 million Covid-related deaths, according to di latest EU figures. But Germany Health Minister Karl Lauterbach tell reporters on Friday say di kontri ""must prepare for a challenge wey we bin never get like dis"", while im public health agency put France, Norway and Denmark as ""high risk"" due to rising number of infections for those kontries. Germany too report more dan 42,000 cases on Saturday, dis wna come down from 50,000 new infections wey dem record on Friday. For Ireland, wia a third of new cases dem record na sake of di new variant, Taoiseach Micheál Martin say dem dey expect ""to see infections for rate wey dey more dan anything we don see to date"". Di warnings dey come as di UK report a record number of Covid infections for a third day in a row - more dan 93,000 - e dey largely driven by Omicron. France close im borders to pipo wey dey travell from UK for business or tourism at 23:00 GMT on Friday, with long queues wey form for di Port of Dover and Eurostar terminals as pipo bin dey try to enta before di ban come into effect. Dem no be di only kontri wey dey tighten dia controls. Earlier dis week, Italy, Greece and Portugal announce say visitors from di EU go need to present negative test result on arrival - even those wey don dey vaccinated. Speaking hours before di new rules come in, Mr Castex say di travel restrictions be part of a series of measures wey dem dey bring in to stop di infections. E include to shorten di gap between di second and third dose of vaccine, and e require a full vaccination to enta restaurants and long-distance public transport. Additionally, all official New Years Eve celebrations and firework displays don dey cancelled. Meanwhile, for the Netherlands, Dutch health experts don say make di kontri go into a ""strict"" lockdown, local media dey report. Prime Minister Mark Rutte say Omicron fit be di kontri dominant strain by January, similar to France. Since late November, bars, restaurants and most shops don dey ordered to close between 17:00 and 05:00 local time. Dis measure bin suppose end before Christmas, but go now continue until 14 January. Di Netherlands record more dan 15,400 infections on Friday - less dan previous days, but far higher overall dan any oda time during di pandemic. Di hospitality industry for di Republic of Ireland say new rules from Monday wey mean pubs, restaurants, theatres and cinemas must close every night by 20:00 local time na sometin wey no go swett dem for belle.. Sports venues go get to operate at 50% capacity or get attendance numbers pegged at 5,000. Wedding celebrations go dey allowed to go on until midnight - with maximum of 100 guests. Already a limit of four households na im dey allowed to socialise togeda inside one home." https://www.bbc.com/pidgin/world-59708776 +politics "Father Mbaka show face afta protesters enta street for Enugu state say e ""miss""" Reverend Father Mbaka di catholic priest wey pipo dey find for Enugu state don show. May pipo bin dey fear say sometin do am afta e no show for service. As di mata dey cause protest for di state, na so di Department of State Services (DSS) tok dem bin no carry di priest. Wetin bin first happen Followers of di Catholic priest and leader of di Adoration Ministry for Enugu, dey protest plus destroy tins for di house of di Catholic Bishop of di Enugu Diocese, Bishop Callistus Onaga, on top accuse say im sabi di where about dia leader Rev. Father Ejike Mbaka. According to di protesters, di last place wey Father Mbaka tell dem say im dey go di Bishop house on Tuesday and since dat night dem neva seem am. So far di Bishop neva comot to tok anytin. Father Mbaka don dey news dis past few days afta im cari prophesy say make Nigeria President Muhammadu Buhari resign. But presidency respond to di prophesy say Mbaka dey attack Buhari becos im ask for contract but dem no give am. Afta some hours of protest, one Toyota Rav4 motor come drive enta di crowd of protesters. Immediately, di protesters come dey happy and celebrate say Reverend Farther Mbaka don come back. Most of dem come dey sing 'oyoyo' 'oyoyo' and later Reverend farther Mbaka come stand up from di roof of di car and wave di protesters. Members gada dis morning for dia Wednesday church programme for Adoration ground for dia usual church programme wen dem announce to dem say dem no no wia Father Mbaka dey. For di announcement, dem say Bishop Onaga bin call Mbaka on Wednesday say im wan see am for im house. Since Mbaka go see Bishop im neva come back and nobodi sabi wia e dey. Na dis announcement make im followers para go di bishop house to ask am wia Mbaka dey. As dem para tire for di bishop na im dem hear say di bishop no dey im house. Na so protesters carry march go Holy Ghost Catholic Cathedral, di Bishop parish. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56998903 +politics EndSars protest: No evidence to show say any massacre happun for Lekki tollgate one year afta - Lai Mohammed "As young Nigerians stage protest today to mark di first anniversary of di allege massacre wey happen one year ago for Lekki toll gate in Lagos, minister of information and culture Lai Muhammed don tok for press conference say di allege massacre no dey real. Alhaji Lai Muhammed say: ""Today mark di first anniversary of di phantom massacre at Lekki toll Gate for Lagos, wey be di highest point of wetin suppose be peaceful protest but later hijacked by hoodlums"". E add say for earlier press conferences, im bin don call di reported massacre for di toll gate di first massacre in di world without blood or bodi. One year later, and despite enough opportunity for di families of those wey dem allegedly kill and those wey dey allege massacre to present evidence, nothing still dey: No bodies, no families, no sure evidence, nothing. ""Where di families of those wey dem reportedly killed for di tollgate? Dem show up for di Judicial Panel of Inquiry? If no be so, why""? Mohammed bin drag CNN and Amnesty International say dem don kontinu to put out different figure to try show say di massacre happun but say wen dem summon dem to di panel to show evidence, dem no show up. E say na shame say CNN wey bin claim say 38 pipo die now dey try convince di world say na only one person die. E say di testimony of ballistic expert before di judicial panel of Inquiry contradict wetin CNN and Amnesty International tok say military no fire any grade live ammunition at protesters for Lekki Tollgate. Lai Muhammed say goment bin set up panel of inquiries to reason di mata. And for one of di National Executive Council meeting on 15 October 2021, NEC bin receive update on di reports of into allegations of Human Rights Violations against Members of Nigeria Police Force and oda security agencies. E say out of di 28 States, 11 States (Abia, Ekiti, Enugu, Gombe, Kwara, Nasarawa, Ogun, Ondo, Osun, Plateau, and Rivers) don submit dia final reports to di Council. ""Govnors of oda states don also show say dem go soon submit dia reports. Oga Lai tok say some pipo don already receive compensation based on di outcome of inquiry wey di panel carry out. Na for last year September na im Nigerian youths enta street with protests to ask goment to scrap one unit of di police force wey dey tackle criminal activities, di Special Anti-robbery squad, SARS. Di protest wey later dey known as End Sars last for about a month before hoodlums hijack am and e lead to killings of civilians, security personnel and also di destruction of properties. Director of Amnesty international Nigeria Osai Ojigbo follow BBC Pidgin tok on top End Sars first anniversary mata. Ms Ojigbo say Nigerian goment dey always do too much anytime e come to violence mata and e no dey justified. She add say di normal tin be say goment suppose invite pipo for dialogue and if concerns dey say di protest fit lead to uncontrolled crowd, di united nations directive on use of force dey clear on how to manage crowd so dat violence no go happen. Di UN no tok say control, dem say manage crowd becos pipo must move, pipo must say, pipo must gada"". She also add say goment move to silence pipo wit might whenever dem wan tok no good and e mean say dem dey invite violence. Osai Ojigbo urge goment to dey true to citizens as police still dey harass pipo and goment no do anytin about am." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58967149 +entertainment Davido donation: Musician birthday fundraiser wey raise N200,000,000 dey go to orphanage for Nigeria "Ogbonge Nigerian musician David Adeleke AKA Davido don release statement to tok how e go spend di money wey e raise ontop social media for im birthday Now, di singer don say e go give two hundred and fifty million naira to orphanages across Nigeria. Davido wey go clock 29 years old on November 21, 2021 bin make post say e wan raise one hundred million naira - e call on friends and associates to contribute one million each for am to use take clear im Rolls Royce from port. Within hours wey im post dis request on im verified Twitter account and Insta story on Wednesday, Davido get more dan di hundred million e bin request. For inside statement, di singer say e raise two hundred million naira from di fundraiser but e add im own fifty million to make am two hundred and fifty million. Di singer wey thank im fans, colleagues and friends wey donate say dis fundraiser na something e intend to do every year for im birthday. ""I don always get passion to give back, in view of dis, I dey delighted to announce say all di funds wey I receive, wey reach N200,000,000 go dey donated to orphanages across Nigeria as well as Paroche Foundation. In addition, I dey make a personal donation of N50,000,000 wey go bring di total to N250,000,000."" Di singer tok for di statement. Di statement also list di committee members e appoint to make sure say di process dey transparent. Di mata of di fundraising bin burst pipo head throughout di day wen Davido call out for pipo to donate one million naira give am. Pipo like DMW star, Perruzzi to Big Brother Naija celebs dem like, Dorathy to even di mama of im first pikin Sophie Momodu, Femi Otedola, Fireboy DML bin drop bar (di money). Nigerian musician, Davido don make many music since im start im career for 2010. Born on 21 November, 1992 di Nigerian-American singer na heavyweight for Nigerian music industry Forbes for 2020 label Davido as Afrobeats superstar. Dem say e be one of Africa biggest musicians. Since im rise to fame, Davido don win multiple awards, including BET awards and MTV awards. He also dey signed on many endorsement. For 2008, he make di Forbes Africa 30 Under 30 list. Davido get 9.7 million followers on Twitter." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59355182 +business Gridco say excess power supply cause nationwide dumsor "Ghana Grid Company (GRIDCo) say de nationwide blackout wey Greater Accra Region, Central, Western, Ashanti, Northern Region den stuff be sake of excess power supply which shut down dema thermal plants. Chief Executive of GRIDCo, Jonathan Amoako Baah, explain say de blackout happen afta power wey dem dey supply to Côte d'Ivoire reverse to Ghana again. Ghana dey export about 100 Megawatts from dema system give Côte d'Ivoire system, but Côte d'Ivoire suddenly lose dema lines to Mali which cause over-generation sake of that Côte d'Ivoire start dey export power back to Ghana. ""De power plants for Ghana be sensitive to power fluctuations, dis be what cause de shutdown of thermal plants for Ghana which caused de outage,"" Mr Amoako Baah explain. More Ghanaians go on top of social media take share dema frustration over de power outage." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50570258 +politics Wetin Ruto, Odinga, President Kenyatta tok with US senator Coon "Kenyan President-elect William Ruto and im main opponent for di recent election Raila Odinga meet with US Senator Chris Coon. Senator Coons bin dey on five-kontri African tour wey im visit dis ogas dem for Kenya. Di US also praise President Kenyatta for making sure say peace and order dey during di election. Kenyan President-elect William Ruto tweet about di tok-tok wey im do with Congressional Delegation from di United States wey Delaware Senator Chris Andrew Coons lead come in di company of US Ambassador to Kenya. Di tok wey hold for Nairobi county touch on di just concluded elections for di kontri, Ruto tok. And also areas of cooperation between Kenya and United States. Ruto say dem dey committed to deepen relations and further partnership for di mutual benefit of di citizens of di two kontries(US and Kenya). Also, US Embassy Nairobi tweet say dem discuss di US – Kenya strategic partnership, promotion of peace and security for di region and ways to strengthen di economies of di two kontri. Senator Coons has also meet with Raila Odinga to discuss ""shared democratic values,"" according to di US embassy Twitter account. Raila Odinga wey be di main opponent for di recent election, come later tweet about di 'candid discussions' wey im get with di US senator. E say im discuss on developments around di kontri general election and bilateral relations with di Congressional delegation of di US Senate and House of Representatives. Raila add say im and e pipo reiterate dia commitment to pursue legal means to resolve issues around di election results. On Thursday, State house Kenya tweet say President Uhuru Kenyatta meet and hold discussions with visiting US Senator Chris Coons wey pay courtesy call to am for State House Nairobi. During di vist, Senator Chris Coons commend President Kenyatta for making sure say peace and stability dey during di election period. President Kenyatta on im part, tok say Kenya go remain steadfast in bringing di principles of good governance. E say dis na to make sure say di kontri uphold dia position of shinning example of democracy for di continent by maintaining peace during dis transition period. “My greatest desire na for peace to prevail and we fit set example for dicontinent and di world,” President Kenyatta tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c19m1pxvxv7o +sports Transfer market: Ronaldo, Lewandowski, Dybala, Coutinho and Philips - What next for dem 37 year old Manchester United star Cristiano Ronaldo don meet im agent Jorge Mendes to discuss im future. (Sun) Bayern Munich striker Robert Lewandowski dey attract interest from Manchester United (Bild- Germany) Aston Villa Coach dey interested in signing Phillipe midfielder Coutinho permanently but di club need to cough out €40m and also di player go need reduce im £480,000 weekly salary (Telegraph) Also di same Aston Villa dey interested in Kevin Philips of Leeds United in case di club fall into relegation, some oda clubs don also show interest (Athletic) Juventus dey think of to increase striker Paulo Dybala contract for di club and also to bring back midfielder Paul Pogba wey dem sell to Manchester United for 2016 ( Tuttosport Italy) Chelsea coach Thomas Tuchel tell im defender Andreas Christensen to forget about move to Barcelona and remain for Stamford Bridge (Mirror) Luke Shaw dey contemplate adding more years to im Manchester United career (90min) Arsenal dey plan to buy two strikers and a midfielder at the end of season for di revamping wey dem wan do for di club (Standard) Sevilla don increase amount to be paid for dia player Diego Carlos to €80m na Newcastle bin wan buy the player for January transfer window but di deal collapse oda clubs also dey interested. (Footmecarto France) E dey possible say Spanish La Liga player Bryan Gill go continue im stint with Valencia as di club don show interest to keep am. (Star) Dutch and Ajax player Ryan Gravenberch get chance to move to Barcelona at di end of season as di club don show interest. (Fabrizo Romano) https://www.bbc.com/pidgin/sport-60679277 +entertainment BBNaija 2021: Liquorose high for di last Saturday Night party as Biggie bring all di evicted housemates Music, dance, alcohol and good vibes dat na di mood of di last Saturday night party for Big Brother Naija house. Di theme for di party according to Big Brother na 'champions party' and housemates no disappoint, Di ladies slay wit dia outfit and di guys look sharp too, as dem dance di night away. Dis na some of di highlights of di 'Shine Ya Eye' season party. All 20 housemates wey bin don chop eviction dis season come back di show for di Saturday night party wey happun inside di arena. Biggie divide di arena into two parts di evicted housemates bin dey one side while di finalist dey for anoda side. Although dem fit see each oda but dem bin no dey allowed to share informate. To get dia groove on, DJ Demola and DJ Embassy supply di music for di party. Dem play back to back hits for di housemates wey enjoy di gbedu wit dia different dance moves. DJ Demola play for di first part of di night before DJ Embassy take ova for di second part. Dis season some ogbonge Nigeria DJ don show face for di Saturday night party. All di housemates look sharp wit di outfits for di Party. Yousef resemble Arabian prince wit im outfit. While Maria and Nini wear fine sequence dress. Na suit Yerins and Kayvee wear wit turtle neck shirts and Saskay wear one white dress. Most of di housemates bin dey dance wit each oda all night, but some of di guys no just send. Queen na one of di pipo wey dance in front of di mirror throughout di party. Small drama bin happun for 'Emmarose' ship last night afta di party. Liquorose bin high afta di party. Emmanuel and Angel carry her go room to try calm her down. For inside di head of house room she start to cry and tell Emmanuel say she dey tired of falling in love because dem dey always break her heart. Emmanuel still stay inside di room wit her as she dey tok. Na on Sunday di show go end, wen di organiser go announce di winner from di six remaining housemates. Whitemoney, Liquorose, Pere, Cross, Angel and Emmanuel na di finalist for dis season. Afta 72 days, inside Biggie house one of dem go win di grand prize wey be N90million naira worth of prizes, di biggest money any winner don get from di reality show since dem start am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-58778484 +entertainment Nigeria Spider-Man: Jonathan Olakunle dey fight for cleaner society Jonathan Olakunle wey don dey do environmental clean up exercise since 2004 dey dress like spider-man wen im wan go clean up for Osogbo, southwest Nigeria. Olakunle say im dey do dis one becos im no dey like see dirty everywia. Video: Joshua Akinyemi https://www.bbc.com/pidgin/media-61142637 +politics INEC: Court send university professor to prison for Akpabio 'fake INEC result' in Akwa Ibom "Nigeria election office, Independent National Electoral Commission [INEC] say dem send Professor Peter Ogban go jail because di man challenge dem to carry am go court, na INEC oga for Akwa Ibom State tok dis one. Justice Augustine Odokwor of di State High Court wey dey sidon for Ikot Ekpene, Akwa Ibom State sentence Prof. Ogban wey be Unical Professor go 36 months for prison after di Independent National Electoral Commission (INEC) drag am go court for electoral malpractices. Prof. Ogban na Don for di Department of Soil Science for University of Uyo and University of Calabar and im bin falsify result in favour of di All Progressives Congress (APC) as against di People's Democratic Party (PDP) wey win di election. Di court find Professor Ogban, wey be di collation officer for Ikot Ekpene senatorial district for di 2019 National Assembly election guilty of announcing fake result in favour of di Minister of Niger-Delta Affairs Senator Godswill Akpabio wey be candidate if di APC for di election. Di offences contravene section 123 of di Electoral Act with penalty of 500 Thousand Naira fine or 36 months imprisonment or both. Justice Odokwor wey tok say im judgment dey in line with INEC Electoral Offences and Penalties for di 2019 general elections, also knack di Professor Fine of 100 thousand naira for electoral malpractice for di elections. Clement Onwenwunor, wey represent INEC tell journalists outside di court say di judgment go serve as big lesson give odas wey dey like to do mago-mago for election mata. For im side Anthony Ekpe, di defense counsel, tok sey di Professor go use oda legal means to get justice for di mata. But Oga Mike Igini, INEC Resident Electoral Commissioner for Akwa Ibom State wey institute di matter tok say, ""Afta di 2019 general elections we bin sidon look wetin happun for di elections wey come help us sabi areas wey we identify weaknesses so dat we no get problems for future elections. ""We bin invite some of di Professors make dem come brief us about wetin happun during di elections for di State but some of dem no gree come. Bus one of di professors bin tok sey im dey fear to come. Na dis tin make us write go our head office for Abuja say make dem set-up panel make dem invite di Professors but still some of dem no gree come. ""Instead, one of di Professors come tell im Lawyer make e write INEC say make we no invite am for any debriefing even as we get plenty evidence against di Professor. But di Professor tok say im go rather go Court. Na dis Professor challenge us say make we go court. Dis na di outcome of di court wey dem say make we go. ""Di Law don yarn. Wetin dey important pass for us now na say di integrity of election process, public feat and confidence go always take priority pass any consideration. Dat na why we go continue to dey enforce di rule of di Electoral Act.""" https://www.bbc.com/pidgin/world-56528761 +politics Lady Hale: Supreme Court say Boris Johnson decision to suspend UK Parliament no follow law "Supreme Court rule for UK say Prime Minister Boris Johnson decision to suspend Parliament no follow di law. Oga Johnson bin suspend Parliament for five weeks early September, but court say e dey wrong to stop Members of Parliament to carry out dia duties ahead of to waka comot form European Union alias Brexit on 31 October. Supreme Court President Lady Hale say ""di effect on di fundamentals of democracy bin dey extreme"". Downing Street - di goment house for UK say dem dey ""chook eye for di verdict"". Oga Johnson been argue say im bin wan carry out di suspension ahead of di Queen speech so im go fit tok about im goment new policies. But some pipo say im bin dey try stop MP so dat dem no go fit chook eye well-well ontop im Brexit plans. For dia conclusion, Supreme Court President, Lady Hale, tok say: Di effect on our democracy dey extreme."" She add say: "" Di decision to advise her Majesty to suspend Parliament dey unlawful because e fit frustrate or stop Parliament to do dia work without any proper reason."" Lady Hale say all 11 judges wit one mouth say di decision to suspend parliament no suppose happun - and now na for di Speakers of House of Commons and Lords to decide wetin dem go do next. Commons Speaker John Bercow happy for di ruling and say Parliament ""must meet without delay"", im add say im go now consult with party leaders ""as a matter of urgency""." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49809441 +entertainment Dudu Heritage: Bimbo Oshin husband burial photos as family lay am to rest "Di burial of popular Nigerian actress Bimbo Oshin husband, Oladiran Ishola Ibironke wey many pipo sabi as Dudu Heritage don take place for Ibadan, di Oyo-state capital, South-west Nigeria dis Friday. Plenty Nollywood actors, golfers and celebrities actors turn up for Ibadan Golf Club to pay dia last respect to Dudu Heritage wey be di Captain of Ibadan Golf Club before im death. According to reports, di socialite, Oladiran Ishola Ibironke bin slump and die as e dey play golf on September 12, 2021. Di burial programme start wit tree planting wey be normal golf tradition for di yard of di golf course. Vice-Captain of di club, Tunji Oladosu for inside statement announce say ""Im burial activities go begin on October 14 wit Christian wake and Night of Tributes. On Friday, we go plant tree as our tradition for members at a time like dis."" E say di burial of di Nollywood actress husband go dey honoured by golfers from all over di kontri. Actors wey present for di burial include Adewale Adeoye, wey many pipo sabi as Adewale Elesho, Muyiwa Ademola, Jaiyeola Kuti, Adeniyi Johnson, among odas dey di burial. Plenty pipo for social media don also offer dia condolence to di family and friends of Dudu Heritage." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58932318 +sports "Arsenal transfer news: ""Thomas Partey"" move to Arsenal FC Gunners from Atletico Madrid almost dey sealed" Arsenal dey try conclude deadline day deal for long-term target Thomas Partey from Atletico Madrid. Di Ghana international midfielder, get release clause of £45m. Partey, wey join Atletico for 2011, don make 35 league appearances for Diego Simeone team. Partey, bin win di 2017-18 Europa League and 2018 Super Cup with Atletico, and e just even sign new deal for di Wanda Metropolitano for 2018, until di end of June 2023. Yet e be like say Arsenal ready to force Partey to port before im contract end. If pesin dey wonder say why Arsenal go wan comot big money buy di midfielder on transfer deadline day, we get some ideas why: Obonge passing Partey na midfielder wit di ability to pass short and long wit quality. Goals English football like players wey fit tear shot to score, and Partey sabi am well well. Bravery E dey very intelligent in di way e dey move, and im tackle dey very precise. Ontop that im brave in di way e dey press high. One-touch football Na footballer wey dey strong, and fast, and di way im dey handle ball wit im leg, no get part two. Team helper Many don praise how Partey dey ginger im teammates to play well because e dey bring energy come. Among di completed deals, di Gunners don so far buy Brazilian defender Gabriel Magalhaes for 26m euros (£23.14m) from Lille. https://www.bbc.com/pidgin/sport-54426617 +business Google announce SafeBoda as dia first investment receiver for Africa $1bn fund "Google announce dia first investment from di Africa Investment Fund wey CEO of Google and Alphabet, Sundar Pichai launch during Google for Africa launch for October. Dis first investment be for SafeBoda, one venture-backed company wit investors wey include GoVentures (GoJek), Allianz X, Unbound, Beenext and Justin Kan. For inside statement wey di di Nigeria Agency Lead Nosa Iyamu release, dis go helep drive SafeBoda growth for Uganda and Nigeria, scale up dia transportation-led app. E go help to offer new payment and financial service solution for dia set of customers: passengers, drivers and merchants wey dey grow. One of di co-founders Ricky Rapa Thomson, wey be former boda driver for Kampala, say im sabi say"" we be di lifeblood of Africa cities and we power economic development. E say SafeBoda dey happy say leading global companies like Google see di importance of backing start-ups wey dey work towards dis goals."" Managing Director for Google in Africa, Nitin Gajria add say ""I dey happy about our first investment from di $50M Africa Investment Fund wey we announce two months ago . "" Dis na part of our ongoing commitment to tech startups for Africa. I get firm belief say no one dey better placed to solve Africa biggest problems dan Africa young developers and entrepreneurs. We dey look forward to announce subsequent investments for oda startups."" SafeBoda be one transport app wey dem launched for 2017 to connect passengers to dia community of safer and trusted drivers. Since den SafeBoda don grow to serve over 1 million customers, expand dia transportation-led super app wey dey offer rides, parcel delivery, food and shop, payments, savings and oda financial services. Di company deyBased for Uganda & Nigeria, SafeBoda be one venture backed company wit investors wey include oda ogbonge investors wey. SafeBoda don also work wit number of organizations to helep for road safety and financial inclusion. Some of di companies include Shell Foundation, United Nations Capital Development Fund (UNCDF), UN Women and the Global Road Safety Partnership, plus odas. Di company get more dan 200 employees, more dan 25,000 drivers for im community and don complete over 40 million orders. SafeBoda say dem dey grow dia team for both Uganda and Nigeria. Internet technology giant, Google bin announce di ogbonge investment of $1 billion for Africa for October dis year. For one Google for Africa event, oga of Alphabet Google, Sundar Pichai bin say di investment go dey for over five years. And e go cover initiatives from better connectivity to investment in start-ups as e go help boost di continent digital transformation. E say di investment go be di biggest investment by di US technology company for Africa. Google say di plan na to chook di money inside projects wey go berekete across Africa continent, including Ghana, Kenya, Nigeria and South Africa. West Africa tok-tok person Taiwo Kola-Ogunlade bin tell BBC pidgin say young pipo go benefit past for di investment as 70 percent of Africa young pipo dey below 25 years of age. So young pipo wey get small business go fit take advantage of di opportunity wen e start. Google dey build global infrastructure wey go help bring faster internet to more pipo plus lower connectivity money and one subsea cable Equiano wey go run through South Africa, Namibia, Nigeria and St Helena and connect di continent wit Europe. Google go expand one ""Device Financing"" collabo wey dey wit Kenya across Africa wit partners like Airtel, MKOPA, MTN, Orange, and odas to help millions of first-time Smartphone user gain access to quality, affordable Android Smartphone. Di company say dem go invest in Black-led start-ups through one Black Founders Fund to provide cash awards and hands-on support. Dis one go add to Google support through di Google for Start-ups Accelerator Africa, wey don helep more dan 80 African startups wit equity-free finance, work space and access to expert advisors over di last three years. Di launch of one Africa Investment Fund of $50M in start-ups and provide dem wit access to Google employees, network, and technology to help dem build products wey make sense for dia community. Empower businesses as dem continue or embark on dia digital transformation: dis go be inside collabo wit di non-profit organisation Kiva. Google say dem dey provide $10M for low-interest loan to help small businesses and entrepreneurs in Ghana, Kenya, Nigeria and South Africa to get through di economic gbege wey Covid-19 cause. Young pipo wey dey run small business Business wey di owner be young pesin Business wey employ young pipo Non profits wey dey provide opportunity to young pipo, women Non profits wey dey work to improve lives Plus oda important group for Africa Di company say wetin matter to dem na to bring di benefit of di web to everybody wey dey Africa." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59688311 +entertainment Sound Sultan dead?: Olanrewaju Ganiu Fasasi AKA Sound Sultan profile Sound Sultan be one Ogbonge Nigerian rapper and songwriter wey many pipo believe say don dey di creative industry for di kontri for a long time and don pay im due to di development of di craft. Infact, some pipo believe say Sound Sultan be one of di pipo wey start modern hip hop music for Nigeria Make we tell you some things wey you gfit no sabi about di Ogbonge rapper. Like everi successful artist, Sound Sultan don tell Nigerians about im self including im birth, education, career and more. Everi bodi know am Sound Sultan but im real name na Olanrewaju Fasasi from Oyo state but dem born am for Jos, Plateau state. Im na rapper, singer-songwriter, actor, comedian and recording artist. Dem born Sound sultan for November 27, 1976 and im na di fourth out of six children. Im father na Liadi Alarape Fasasi and im mama na Adeyinka Ajarat Fasasi. Sound sultan dey married wit three children - one girl and two boys. Sound sultan attend Stepping stone nursery and primary school between 1981 and 1987. Im later move go federal goment college Ogbomosho from 1988 to 1993 for im secondary school education. Sound Sultan get BSc for Geography and regional planning from Lagos state university for 1999. Plenti pipo regard Sound sultan as one of di pipo wey start modern hip hop music for Nigeria. Sound sultan career for show biz start as early as in di 1990s - wia im begin do show to get money to pay for im own studio session. Im start to get interest for music from 1991 as im begin mime for school before im begin write im own lyrics. Sound sultan begin learn how to play guitar after im secondary school education and by 1999 im don get im own band. He attributes his early influence to his elder brother baba dee, who studied theatre arts. Also for 1999 Sound sultan don win plenty local talent hunt shows and by 2000 im release im first single 'Jagbajantis' wey make am blow. Na later as Sound Sultan become popular before Nigerians know say Baba Dee, another music star n aim brother. Sound sultan don work under two major record labels; Kennis Music from 1997 to 2008 and Naija Ninjas from 2008 till now. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57090511 +health Malaria Vaccine: World Health Organization approve malaria vaccine for Africa "World Health Organization say dem dey recommend di broad use of di first proven malaria vaccine to help children for Africa. Dis recommendation dey come afta dem don try di vaccine wey drug giant GSK dey produce for three kontris. During di trials for Malawi, Ghana and Kenya dem find out say di vaccine reduce malaria cases by forty per cent. Malaria parasite dey kill more than four hundred thousand pipo every year - two thirds of dem na children under di age of five inside Africa. Di head of WHO, Tedros Ghebreyesus describe di vaccine as one major breakthrough and gift to di world. As dem don get vaccine for Malaria - afta more than 100 years of trying - dis dey among medicine greatest achievements. Di vaccine wey dem call RTS,S - don prove to dey effective six years ago. Now, afta di success of pilot immunisation programmes inside Ghana, Kenya and Malawi, World Health Organization say make dem roll out di vaccine across sub-Saharan Africa and for oda regions with moderate to high malaria transmission. Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus, director-general of WHO, say dis na "" historic moment"". ""Di long-awaited malaria vaccine for children na breakthrough for science, child health and malaria control,"" e tok . ""[e] fit save tens of thousands of young lives each year."" Malaria na parasite wey dey invade and destroy our blood cells in order to reproduce, and e dey spread through di bite of blood-sucking mosquitoes. Drugs to kill di parasite, bed-nets to prevent bites and insecticides to kill di mosquito don help reduce malaria. But dem feel di greatest burden of di disease for Africa, where more than 260,000 children die from di disease inside 2019." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58821263 +sports To chop just two goals against Super Falcons na achievement - Botswana coach "Nigeria vs Botswana fulltime score for di WAFCON 2022 second group match, show say di Mares dey lucky, dia coach don tok. Gaoletlhoo Nkutlwisang tok dis one afta her team lose 0-2 to Nigeria for dia second match of di 2022 Women Africa Cup of Nations for Morocco. Di Mares' coach say for her team to concede just two goals from Nigeria “na achievement”. Nkutlwisang for her post match reaction say she dey proud of wetin her team play she bin dey expect to chop plenty goals from Nigeria. “I dey very proud becos wen you play against Nigeria and dem no beat you by nine goals, na achievement for us. “Looking at di first 11, we play wit more of home based players. I think na achievement for us."" On her part, Nigeria Super Falcons Coach, Randy Waldrum don describe di Nigerian media as toxic. Di Super Falcons score for first and second of di match wit Ifeoma Onumonu scoring di first goal for di 21st minute. Christy Ucheibe wey enta as di second half begin to replace Rita Chikwelu, score di second goal. But during di post-match Press Conference, Waldrum say dem dey try to qualify for World Cup and dem no want make media dey follow dem up and down. ""We dey try to qualify for di World Cup, di players need to dey away from pipo so dem go fit focus. ""We no want make tori pipo dey follow us around. Di media for Nigeria dey very negative. ""Everyday our camp dey in high spirit and di team dey for better place, so we no need distraction.” Nigeria next match na on Sunday, against another first timer, Burundi and a win of any form go confam Super Falcons qualification go di next round. Botswana go face their Southern African rivals, South Africa wey dem stop from qualifying for the Olympics." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c130y882em0o +sports France vs Germany: Four reasons why you no go wan miss dis group F match for Euro 2020 Di current world champions France go face di old world champions Germany for Euro 2020 group F match for Allianz Arena on Tuesday evening by 8pm Nigerian time. Dis go be di first time France and Germany go ever meet for group stage of a competition. Germany form ahead of dia first game of Euro 2020 get as e be. Die Mannschaft draw 1-1 wit Denmark before dem hammer Latvia 7-1 for friendlies match leading up to the competition. France dey come into dis game wit two 3-0 wins, against Wales and Bulgaria, and go hope say dia recent fine form go continue. See five oda reasons why you no go wan miss di Group F match of dis two ogbonge teams. Karim Benzema go hope to start for im first major international competition since di 2014 World Cup for Brazil. Di Real Madrid striker bin play di last two friendlies alongside Kylian Mbappe for di French attack. Even though im get injury for di Bulgaria game, Didier Deschamps say im suppose dey available. Some players go play against dia teammates for dis ogbonge game. Chelsea Antonio Rudiger, Kai Havertz and Timo Werner go play against N'Golo Kante and Kurt Zouma, while Benzema and Raphael Varane go, go against dia teammate of seven years Toni Kroos, di three players dey represent Real Madrid. A total of 12 players fit play for Allianz Arena for Bayern Munich, so na like home away from home for those players. Afta Kante become Champions League winner two weeks ago with Chelsea, im go begin anoda chapter for im career wia im go hope to guide im kontri to European success. Afta joining Leicester City for 2015 as an unknown quantity, Kante career blow afta im join Leicester City for 2015 as unknown player to become one of di best for di world. Di 30-year-old don win World Cup, Champions League, Europa League, Premier League and FA Cup all in di last five years, di only major competition wey im neva win yet na di European Championship. If Kante fit help im kontri win di European title, den im go serious contender for di Ballon d'Or award. Since di coronavirus pandemic, tins no dey like e be before for Bayern Munich home stadium. Tori be say, di German side originally na only 10 percent attendance dem bin allow inside di inside Allianz Arena for September 2020, but because of restrictions sake of di pandemic, dem bin no fit go ahead. Now wey dem don relax di restrictions, fans don return, but na just 250 fans bin fit watch di final game of di season. Dis Tuesday night, na 14,500 fans go dey inside di stadium. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57489980 +politics Usman Alkali Baba: Protection of kontri pipo be priority for President Buhari- Osinbajo tok as e decorate new Acting IGP "Nigerian Vice President Yemi Osinbajo don tok say safety and protection of all Nigerians remain a priority for President Muhammadu Buhari's administration. Osinbajo tok dis afta e decorate DIG Usman Alkali Baba as di new acting Inspector General on Wednesday. E add say, ""you dey take office for time wey kasala don bust for our pipo. Plenti threats dey against law, order and public safety."" VP Osinbajo also add say di Police force dey also face im own kasala as dem dey face threats of attacks from terrorists dem for di kontri. Di decoration ceremony bin happun for Aso Rock Abuja, and e dey come afta di President through di Minister of Police Affairs Mohammad Dingyadi bin appoint am to replace Mohammed Adamu on Tuesday. Before im appointment, oga Baba be di head of Force Criminal Intelligence and Investigation Department (FCIID). Dis na as Adamu Tenure bin don end for February afta e spend di 35 years im suppose spend for service but di president bin give am three months extension to continue. Adamu bin dey for Imo state on top di Prison kasala wey burst dia wen di appointment news come." https://www.bbc.com/pidgin/tori-56665328 +sports Cameroon vs Nigeria Wafcon 2022 highlight: Ajibade goal make Super Falcons win "Cameroon and Nigeria Wafcon 2022 quarter final match end in favour of di Super Falcons. Rasheedat Ajibade stunning header for di 58th minute make Nigeria defeat Indomitable Lionesses of Cameroon 1 - 0. Thursday result mean say di Nigeria female national football team don advance to di Semi-finals to jam di host, Morocco. Super Falcons win also give dem automatic qualification for di New Zealand/Australia 2023 Fifa Women's World Cup. Nigeria vs Morocco semi final match go happun for Rabat on Monday 18 July, 2022. South Africa also pick di last automatic World Cup ticket afta dem beat Tunisia by one goal for di oda Thursday game. Super Falcons Coach Randy Waldrum say im team fit celebrate small afta dem pick di World Cup ticket. ""We dey go World Cup, we check off one box because na one of our goals and now wey we don qualify. ""We dey celebrate a little in a smart way today, and den we go prepare for di next goal wey be to win di tournament"". ""Our focus na to beat Cameroon today and henceforth, our team go put di focus on Morocco. 90' Two minutes of extra time. 89' Nigeria dey feel di pressure now late on inside di match. 88' Cameroon dey send plenty players forward and now dem get corner. 86′ Cameroon substitution Abam - comot, Kameni- enta. 85' Nigeria don switch to defence mode now wit few minutes remaining. 83' Cameroon pressure dem force Nigeria defence to make mistake. 80' Cameroon send in a dangerous ball, Nigerian goalkeeper save di ball but Cameroon player jam her as she save di ball wey make her roll for ground injured. 75′ Cameroon push to attack Nigeria but still no way for dem yet. 72' Double substitution for Nigeria Ordega comot- Kanu- enta, Okobi- comot Chikelu- enta. 68′ Cameroon substitution Fatima - enta, Mbeleck - comot. 68′ Ayinde high boot catche Abam. 62′ Third yellow for Cameroon na Onguene collect di card. Goal' Ajibade header beat di Cameroon goalkeeper Okobi run worry di Cameroon defense before Onumonu cross find Ajibade wey head di ball inside di net. 53' Di space between Nigeria attack and midfielder too much e 49' Nigeria get more possession for di opening minute but still lack di creativity to break di Cameroon defence. 40' Nigeria dey pepper di Cameroon defence, wit shots from Ordega and Ucheibe. Di winner of dis match go play di host nation Morocco. 33′ Nigeria with another corner kick but dis time no fit trouble di keeper. 28′ So far di two teams dey struggle to create clear chances. 24′ Nigeria come close! But Mbonu wey bin dey for Cameroon goal do well to block Plumptre header. 21′ Super Falcons win another free kick Okobi step up again to deliver but e no reach any Nigerian player. 12' Di score na 0-0 between Nigeria and Cameroon. Some big names from di two kontries dey di stadium to watch di match. Cameroon Legend and football president Samuel Eto and Nigeria football federation President Amaju Pinnick dey inside di stadium dey watch di match. Dis match na repeat of di 2016 final for Yaounde, di derby dey expected to produce fireworks. Already Zambia and Morocco don qualify for di semi-final round of di competition. On Tuesday Zambia beat Senegal on penalties to progress while Morocco beat Botswana 2-1. 16 Chiamaka Nnadozie 7 Toni Payne 5 Onome Ebi 3 Osinachi Ohale 4 Ashleigh Plumptre 18 Halimatu Ayinde 9 Ifeoma Onumonu 13 Ngozi Okobi 23 Christy Ucheibe 17 Francisca Ordega 15 Rasheedat Ajibade 16 Ange Bawou 12 Claudine Meffometou 6 Estelle Johnson 11 Marie-Aurelle Awona 15 Colette Nzdana 18 Claudia Voulania 7 Gabrielle Onguene 17 Brigitte Omboudou 20 Genevieve Ngo Mbeleck 22 Michaela Abam 3 Ajara Nchout" https://www.bbc.com/pidgin/sport-62171365 +sports Ligue 1 table: Lille, PSG & Monaco battle for French title Today na di final weekend of di top-flight season for France, tense finale dey expected to decide who go dey crowned as champions of Ligue 1. Di top three - Lille, Paris St-Germain and Monaco - dey separated by three points. Leaders Lille dey one point ahead of PSG ahead of final round of matches on Sunday - wey go kick off at 19:00 GMT- dem dey one win away from taking di crown for di first time since 2010-11. Here BBC Pidgin look at wetin promise to be last day of di league season wey tie wrapper. Three teams dey separated by three points with one game to play - Lille fit hold on and end Paris St-Germain dominance? PSG don win Ligue 1 seven times in di previous eight seasons - Monaco become champions for 2016-17 - but start di final day on 79 points, one behind leaders Lille. Last season dem award PSG di title after dem announce say di season no go resume because of di coronavirus pandemic. Dat time, dem bin dey 12 points clear of nearest rivals Marseille wey bin get 10 games left. On Sunday, only victory go guarantee Lille as champions, but di interesting title race fit still see di top three all finish on 80 points if Lille lose, PSG draw and Monaco win. Goal difference fit decide di title. Dat one go favour Mauricio Pochettino PSG, wey get di advantage over their two title rivals. Lille go dey confident of finishing di job at 12th-placed Angers. At di same time, PSG go visit relegation-threatened Brest and Monaco dey away to sixth-placed Lens. PSG head into di weekend fresh from winning di French Cup for di sixth time in seven years after dem beat Monaco for Stade de France - Pochettino second trophy since im take charge in January. Monaco need both Lille and PSG to lose for dem to snatch di title. Even then, dem require big win against Lens because of their inferior goal difference. https://www.bbc.com/pidgin/sport-57217081 +politics Tinubu, Gbajabiamila, Sanwo-Olu, oda South West APC leaders support southern governors ban of open grazing, condemn separatist agitations "South-West APC leaders don endorse di position of Southern Governors ontop di ban of open grazing wey di govnors decide for one summit wey happun for Asaba, Delta state on May 11, 2021. Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu tok inside statement on Sunday, 23, May, 2021 afta di meeting wey e host with di leaders say, di South-West leaders endorse di decision of di southern govnors. Di meeting wey happun behind closed doors for about five hours, happun for di State House for Marina. Sanwo-Olu also add say di APC SW leaders also condemn di separatist agitations and hate speeches wey dey fly around as dem restate dia belief in di unity, stability and sustainability of Nigeria. Sanwo-Olu statement at di end of di meeting tok further say ""true federalism go dey essential in strengthening and improving democratic governance so dat we go fit overcome present challenges and engender durable peace and security. E go empower di states to solve localised issues before dem spread and transform into national ones."" Di statement tok. Di meeting wey na opportunity for dem to discuss di state of di nation and current security challenges wey Nigeria dey face, get in attendance, notable APC South-West leaders like di leader of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila, APC national leader, Bola Tinubu and anoda ogbonge AC leader, Chief Bisi Akande. Na also opportunity for dem to renew di call for restructuring and true federalism. Di APC leaders also express dia concerns on security situation in di kontri as dem stress say terrorism and criminality dey threaten di livelihoods of Nigerians well-well for many areas." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57220974 +business Rivers state Governor Wike don reopen markets for business "Rivers State goment don announce re-opening of all markets for di state wit effect from Tuesday, August 18, 2020 from 7a.m but dem go close by 6p.m daily. Governor Nyesom Wike announce dis one for state-wide broadcast say Rumukwurushe (Oil Mill) and Oginiba Slaughter Markets still remain closed. Di Governor say as markets resume business, dem must operate in strict compliance wit di established protocols on wearing of face masks, washing of hands and maintaining social distancing come add say di Goment lift di ban on markets to increase economic activities for di State. ""Any market wey open to di public and fail to comply strictly wit all dis protocols go close down. We go prosecute di market managers while di shops wey no comply go dey forfeited to di State Government without notice."" Governor Wike also say Churches fit now hold services wit 50% of dia hall capacity as far as di leadership fit enforce wearing of face masks and washing of hands for di entrance by worshippers. ""Di ban on outdoor sports activities for Port Harcourt Club, Golf Club and di Port Harcourt Polo Club also dey lifted. ""Members of dis clubs must also comply wit di established Covid-19 protocols or risk anoda closure. But, all night clubs, cinemas, bars and in-service restaurants still dey banned until further notice. Di established restrictions on public burials and weddings still dey in force."" Di Governor add. Im come direct all local goment Chairmen to ensure strict compliance wit di protocols for dia local loment areas. Governor Wike say dem don also increase capacity for di State surveillance, contact tracing, testing and treatment of positive cases in line wit di National Centre for Disease Control (NCDC)." https://www.bbc.com/pidgin/tori-53812992 +entertainment Karibi Fubara death: Stella Fubara confam Nollywood actor die afta cancer battle "Nollywood actor, Karibi Fubara don die. Im family members announce am on top dia social media page. One of im sisters, Stella Fubara wey be di Director International Operations for Dubai Tourism post for Instagram say, ""E be warrior, now e be angel for heaven."" Wednesday 15 December, 2021 na im Stella Fubara confam say di Nollywood actor die Another sister of di actor Aya Fubara Eneli post say ""Joy dey because Karibi dey for better place. Sadness dey because e no longer dey dis earthly realm."" She say ""My brother, Karibi Fubara, don join di ancestral realm. I dey devastated, but not hopeless. He lived fully and with joy. Live behind a great body of work. E go be a powerful ancestor. I love you."" Michael Fubara wey announce im death on behalf of di Fubara/Okereke family say; ""For all of us wey love am so dearly, make we use joy to console each other during periods of sadness. We go dey in touch wit further details in di future. "" Plenty ogbonge celebrities and actors wey include Funke Akindele, Ebuka, Linda Ejiofor, Kate Henshaw, Omoni Oboli, among others don pay tributes to di actors. Di ""God calling"" actor bin dey diagnosed wit cancer for 2020. For one of im Instagram post afta di surgery, e say na around Easter e bin receive di news say im get large mid-stage kidney tumor/cancer. And on 3rd May, 2021 I had a very successful surgery remove about 90% of the tumor. E add say ""im dey home now dey rest, reborn, & learning to live again."" Until im death, Karibi Fubara na Nollywood actor wey become popular afta e feature for one movie 'Before 30'. E later feature for oda popular movies wey include God calling, Quams Money, Castle and Castle, Royal Hibiscus, among odas. Karibi, marry popular Nollywood fashion entrepreneur, Yolanda Okereke for 2019." https://www.bbc.com/pidgin/tori-59674157 +sports Martin Odegaard: Arsenal target Real Madrid midfielder as Ozil replacement "Arsenal don identify Real Madrid player Martin Odegaard as possible signing for dis January transfer window. With Mesut Ozil set to join Fenerbahce, di Gunners don enquire about signing di 22-year-old until di summer. Odegaard don fall out of favour for di Bernabeu in recent months. Odegaard, wey many bin tip as a future star when e move to Spain from Norwegian side Stromgodset as a 16-year-old, impress on loan for Sociedad last season. After e return to di Bernabeu in di summer, it look like e fit become first-team regular under Zinedine Zidane, wey coach am for di B team wen e first join di club and now dey in charge of di senior side. But after e start di first two La Liga games of di season, Odegaard don only feature once from di start of a league game since and that na since 21 November. But Spainish football expert, Guillem Balague don also tell BBC say ""Arsenal are no be di only Premier League club wey don make enquiry about am but e go also like to go back to Real Sociedad,"" where e bin dey on loan last season. Balague add say ""di adaptation process go dey easier there and all e want na to play."" Who be Martin Odegaard Madrid sign di talented playmaker for January 2015 from Stromsgodset wia e make e name and di club send am immediately to their youth side, RM Castilla. Di player also don go on loan spells for Heerenveen, Vitesse and Real Sociedad. Martin Odegaard catch di the attention of di footballing giants across Europe wen e enjoy breakthrough season for 2018/19 with Vitesse. Im record goal contribution of 18 goals and assists for di Eredivisie outfit during e loan spell. Arsenal manager Mikel Arteta bin face questions on Thursday about Odegaard but e refuse to speak about specific targets. However, e make am clear say e dey hope di Gunners go dey active before di 1 February transfer deadline. Dem release Sokratis Papastathopoulos from e contract dis week, while Sead Kolasinac and William Saliba don already leave on loan deals and Ozil's switch to Turkey dey set to go through but na quarantine rules dey delay am. ""We done do di first part more or less and we dey focuse now on di second phase,"" na so Arteta. ""Obviously dis market and di context make am difficult, but we dey look at options and we go see wetin we fit do. ""We dey look at various positions because di movement we don make dis window with some players wey leave di club don leave us a little bit short for certain areas. ""So if we fit, we go do am and if we no fit, we go keep going with wetin we get.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-55761976 +sports Serena Williams: Di ‘never give up spirit’ of di ogbonge tennis player """I no go fit continue to play like dat"" dis na wetin Seven time champion Serena Williams tok afta she crash comot from Australian Open on Friday morning and lose 6-4 6-7 (2-7) 7-5 to Wang Qiang from China for third round. ""I no fit play like dat. I literally no fit do dat again. E dey unprofessional. E no dey cool."" Senera tok As e be so Serena search for her 24th grand slam title go continue. Wang bin dey serve for di match when di game dey 5-4 but Williams broke her for di first time come win di tie-break to level di game. Di 28 year old Wang wey be number 27th seed for world tennis ranking, recover come seal victory for her third match point. Wen tori pipo ask Serena wetin she think afta di game, she say ""I honestly no think say I go lose datat match."" She add say ""I just make far too many errors to be professional athlete today."" Tori be say dis Friday defeat na Serena earliest exit for Australian Open since 2006, when she lose for dis stage to Daniela Hantuchova. Dis na Williams 23rd year as professional tennis player and she still dey eye Margaret Court record of 24 grand slam singles titles. Di last time wey 38 year old Serena win grand slam na 2017 when she beat her sister for Australian Open final to win her 23rd title and na di same year she born her daughter too." https://www.bbc.com/pidgin/sport-51233244 +business Climate change: Nigerian, 15 oda young pipo file complain against five world economies "Sixteen young climate activists on Monday file complain with di United Nations, point finger say five of di world major economies don violate dia human rights sake of say dem no do enough to stop di climate crisis. 12-year-old Nigerian Deborah Adegbile, 17-year-old Raslene Joubali from Tunisia and 17-year-old Ayakha Melithafa from South Africa na di three Africans wey follow lay di complain. Dem file di complain small time afta ogbonge activist from Sweden Greta Thunberg change am for world leaders with her speech for di UN Climate Action Summit wey happun for New York , America. Di petition accuse five kontries, Germany, France, Brazil, Argentina and Turkey wey dem say don fail to do dia part under di Convention on di Rights of di Child. One 30-year-old human rights agreement wey be di one kontries don sign pass and wey dey valid well-well throughout history. Dis action dey come as UN host Climate Action Summit on di first day of di General Assembly wia plenti leaders tok about dia plans to reduce dia kontri carbon footprint. For press conference di children hold near wia di summit dey happun, Thunberg and di oda children express dia frustration say world leaders too slow to fight climate change. ""Di message wey we wan send na say enough is enough,"" Thunberg tok. Last week, di 16-year-old Swedish climate activist Thunberg lead children dem and adults from 150 kontries for ogbonge climate strike on Friday say di world no dey do enough to fight climate change. Adegbile wey dey live for Lagos, Nigeria say she begin to dey advocate for change afta she see di way climate change dey cause palava. She say rain wey bin dey fall from April to September now don extend to December. Every time rain fall now for Lagos, flood dey happun and her parents must carry her and her younger ones go school because dem no fit waka inside di deep water. Adegbile dey also advocate to protect di ocean through plastic reduction as she don take eye see how e dey affect di ocean and animals off di coast for Lagos. Dis action dey come as report come out say di sign and impact of global warming dey happun fast- fast and 2014 to 2019 na di hottest for record." https://www.bbc.com/pidgin/tori-49806982 +entertainment Chimamanda Adichie don win overall Women's Prize for Fiction award "Chimamanda Ngozi Adichie Half of a Yellow Sun novel don receive fresh accolades afta e win award as di best book to ever collect di Women's Prize for Fiction for e 25 year history. Di Nigerian born author wey win di prize for 2007 bin dey choose from public vote between all di 25 winners wey don win before as part of di anniversary of di prize. Dem bin formerly call di prize di Orange Prize and the Bailey Prize and dis year prize na one and only. Half of a Yellow Sun wey comot for 2006 with global accolades, dey set for Nigeria for di Biafra War and bin showcase di end of colonialism, class, race and female empowerment. For 2013, dem turn am to feem wey Chiwetel Ejiofor and Thandie Newton follow act inside. Adichie tok say ""I dey especially moved say dem vote me Winner of Winners because na dis prize carri plenti readers come my work and na im introduce me to plenti talented writers."" Madam Adichie don win ova 27 award for her writing career. Author Kate Mosse wey be di founder and director of di UK based prize say she bin dey thrilled say Half of a Yellow Sun win di award. E pass 8,500 pipo wey vote for di prize and dem even invite dem to tok for inside di prize digital book clubs to fit access newly created online reading guides plus author interview." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54875521 +entertainment Audio cassette tape inventor Lou Ottens die at age 94 Di Dutch engineer invention transform di way pipo listen to music during di 20th century. Lou Ottens, di engineer from Netherlands wey pipo sabi as father or audio cassette tape, don die at di age of 94. About 100 billion cassette tapes na im pipo don buy around di world since di time e enter market for 1960s. Ottens invention of di audio cassette transform di way pipo listen to music because before then, na ontop big vinyl records pipo dey take buy dia music. Di engineer die for im hometown of Duizel last weekend, im family bin tok on Tuesday. Ottens become di head of Philips' product development department for 1960, wia im and im team develop di cassette tape. In 1963, dem showcase am for di Berlin Radio electronics fair and small time after, e turn to worldwide success. Ottens also dey involve in di development of compact disc, wey don sell pass 200 billion copies worldwide. Im retire for 1986. When dem ask am about im career, e say im biggest regret na say Sony - instead of Philips - na im create di cassette tape player, di Walkman. Although compact discs (CD) replace begin replace cassette during di 80s, di small rectangle tin don dey do ‘come back’ in recent years. For example, ogbonge musician like Lady Gaga even release her album ontop tape. But in Africa, some go say no time dey wen cassette leave dem, because many pipo especially for rural areas still dey use cassette till today. Not to mention say vehicles still boku ontop African roads wey still get audio cassette players inside. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56360221 +politics Capitol Hill protest: Trump blocked from Twitter and Facebook, oda tins wey happun afta Donald Trump supporters storm Congress to protest US election result "Washington DC police say four pipo don die during di storming of di Capitol building on Wednesday. In addition to di woman wey police shoot, three odas die as a result of ""medical emergencies"". So far, more dan 52 pipo don dey arrested - 47 of dem, sake of curfew violations. Dis one na afta Pro-Trump protesters storm Capitol Hill, wia Congress bin dey do joint session to certify di results of di 2020 election - and Joe Biden win. Congress stop di session as di violence dey go on, but later meet again afta di violence to certify Joe Biden election win. E start afta di good news for Democrats as e be like say dem go take control of di US Senate with two projected wins for Georgia President Donald Trump address im supporters for Washington DC, say e no go concede and say now no be di time for ""weakness"" As Trump wrap up im speech, Congress meet for a joint session to certify di results of di 2020 election - and Joe Biden win. Na di final step before Biden's inauguration as the 46th president on 20 January One large group wey bin wan scata di proceedings for Congress, pro-Trump supporters by-pass di barricades, jump walls and force lawmakers to evacuate di premises. Di violence continue for hours. Di mob - some wey wear body armour - use chemical irritants to attack police, according to Washington Metropolitan Police Chief Robert Contee. Dem shout and waved pro-Trump and US flags as dem roam di halls, dey demand make dem overturn di results of di presidential election. Several thousand National Guard troops, FBI agents and US Secret Service na im dem deploy to help di Capitol police wey no fit handle am alone. Authorities recover two pipe bombs, one from di Democratic National Committee offices, not far from di Capitol, and one from di nearby Republican National Committee headquarters. DC National Guard deploy go di Capitol, to back up law enforcement for di place. Wednesday attack na di first time dem go break enta di US Capitol since di War of 1812, according to US Capitol Historical Society experts. British troops, wey Vice Admiral Sir Alexander Cockburn and Major General Robert Ross lead - set fire to di still-under-construction Capitol afta dem invade DC for August 1814 (though di building survive thanks to rain). In retaliation for di Americans burning of Upper Canada capital for York one year earlier, di British troops also set fire to oda parts of di city, including di White House. Social media giants don announce say de go bar President Donald Trump account. Twitter announce say President Donald Trump account go dey locked for di next 12 hours due to im tweets about di election earlier today. ""As a result of di unprecedented and ongoing violent situation fo Washington, DC, we don ask for di removal of three @realDonaldTrump Tweets wey dem post earlier today for repeated and severe violations of our Civic Integrity policy,"" di social platform tok. If Trump no remove di three tweets in violation, di account go remain locked. Facebook don also tok say dem go bar President Trump from posting for di next 24 hours. Di company cite policy violations ontop di president page. Meanwhile di mayor of di US capital city don extend public emergency for 15 days until afta inauguration day. Di order lasts until 15:00 on 21 January, di day afta Bid dem go swear Biden in. Di city dey already under curfew dwey di Mayor declare from 18:00 on Wednesday to 06:00 (23:00 to 11:00 GMT). Global leaders don dey express dia shock over di attack for di US capital. Dis na probably good time to go over di facts of di election results, contrary to wetin President Trump dey tok." https://www.bbc.com/pidgin/world-55570816 +sports Volleyball Championship: Cameroon beat Kenya for komot champions Congratulate messages di pour from all corners for Cameroon Volleyball Lionesses as deh win dia second title for Egypt. Na for 2017 weh Cameroon beat Kenya for komot Champions, afta Kneya bin don win nine taims. Cameroon beat Kenya 3-2 sets (25-17;25-27;25-23;23-25,16-14) for komot champions, and deh also get best player, libero and scorer. President Biya na one of de pipo dem weh deh glad for dis win sotei go congratulate de players for twitter. Den Prime minister follow for send e own congratulate for de African volleyball champions. Cameroon army no lef for back as deh join for congratulate de volleyball Lionesses, African champs. De champions go reach Yaoundé Nsimalen Airport for morning taim. Na so Narcisse Kombi Mouelle minister of sports and physical education don tok say make all man komot welcome de woman dem weh deh don make kontri proud. https://www.bbc.com/pidgin/sport-48986756 +business Why flights go dey more expensive as air industry experts warn "Price of airline tickets go increase ""without doubt"", air industry oga don warn. Oil prices don jump as economies dey recover from di covid pandemic and sake of di war for Ukraine. Willie Walsh wey be director general of di International Air Transport Association (IATA), say dem go pass dis cost to consumers. E say dis dey come as price of fuels dey rise. Holidaymakers need to dey prepared for di cost of flights to go up, Oga Walsh tell BBC Sunday Morning programme. Major airlines in Nigeria bin alert dia customers in March 2022 of more flight delays and cancellations in days ahead. Di alert na sake of di scarcity of Jet fuel or aviation fuel wey dem dey experience. E take di intervention of goment ogas inside di oild producing kontri to save di mata. In May 2022, commercial flight operators bin threaten strike to complain of di increase in price of JetA1, wey be aviation fuel, dem later suspend di action. But now, air industry ogas dey warn say flights go dey more expensive across di world. ""Flying go dey more expensive for consumers, without doubt."" Di ""high price of oil"" go ""show for higher ticket prices"", Willie Walsh tell BBC. Oil prices don already dey increase as demand don pick up again as economies dey recover from di Covid pandemic. Di fallout from di war for Ukraine don also push prices up more and more. Di US don announce complete ban on oil imports from Russia. UK dey also phase out Russian supplies by di end of di year. European Union leaders don also tok say dem go block most Russian oil imports by di end of 2022. Dis one mean say demand for oil from oda producers don increase, and e don lead  to higher prices. IATA oga say fuel prices dey at record highs, and say ""oil na di single biggest element of any airline cost base"". “No mata how e be, las-las dem go pass high oil prices through to consumers in higher ticket prices."", e add am. Russia na di third biggest oil producer for world afta America and Saudi Arabia. Out of di five million barrels of crude oil dem dey export evri day, more than half of dat dey enta Europe. UK oil demand from Russia na 8% and US only import 3% of Russia for 2020. Meanwhile, President Vladimir Putin bin don threaten say e go cut gas to ""unfriendly"" kontris if dem no start to pay for dia gas import wit Russian roubles. Dis move dey come sake of di war on Ukraine wey don cause many kontris to sanction Russia. Di US, UK and EU also, don already place restrictions for oil and gas imports from Russia, afta dem invade Ukraine for February. US declare total ban on di import of Russian oil, gas and coal. UK wan phase out Russian oil by di end of di year. UK goment say dem wan allow enof time for dem to find oda places to get oil from. Deputy Russian Prime Minister Alexander Novak say to reject Russian oil go create kasala for di global market. Oil and gas prices don dey high since di invasion of Ukraine and if Russia stop to dey export dia own, di prices fit high even more." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2q5ewprv3go +sports UFC 263: Israel Adesanya vs Marvin Vettori fight & how to watch "Nigeria UFC champion Israel Adesanya go defend im middleweight title dis weekend. Adesanya go put im title on di line against Marvin Vettori for wetin go be im first rematch for im martial arts career. Di fight go happun in front of full crowd for Gila River Arena for Glendale, Arizona, for America For im last fight for March Adesanya, move up to light heavyweight but im lose to Jan Blachowicz. Dis na everything you need to know about Israel Adesanya UFC 263 fight Adesanya and Vettori na di main event of di night. Di two fighters bin first face each oda for April 2018 for Adesanya second fight for UFC. Di Nigerian claim victory dat night via split decision, and Vettori dey determined to revenge di fight. ""I get di advantage because I am be superior fighter"", Vettori tok during pre-fight press conference on Thursday night. ""I fit do everything. Im no get all di answers for wetin I go bring to di table. Im dey better. Im dey sharper. But e no add nothing, you know? ""Honestly speaking, since our last fight, look di kain of pipo him don fight and di ones wey I don fight—difference dey,"" Adesanya tok. But Vettori interrupt am as e come begin question di champion recent results. ""You lose against (Yoel) Romero, you lose against me, then you lose against Blachowicz,"" im tok. ""Who you beat? You beat 'Borrachinha' (Paulo Costa)? And im bin dey drunk di night before? Who you beat? Great, wow!"" ""Who you don beat?"" Adesanya ask am. ""Tell me, who you don beat? Name three top-10 opponents you don beat. Name them. Exactly."" Cable company DSTV go show d match live on SuperSport. Dem go begin broadcast di main card events from 3.00am on Sunday for SuperSport Action, and SuperSport Variety 3 (DStv channel 201, 210 & 208)." https://www.bbc.com/pidgin/tori-57455076 +politics Akeredolu wins: Biography of Rotimi Akeredolu di 18th Govnor of Ondo State When dem born am 64 years ago for di Yoruba town of Owo, im know no say im go one day become Senior Lawyer and two-time Nigerian governor. Dis na di story of Arakunrin Oluwarotimi Odunayo Akeredolu, SAN, di 18th Govnor of Ondo State for South West Nigeria. Akeredolu wey win re-election on Sunday 11 October 2020 na Senior Advocate of Nigeria. Born on 21 July 1956 for Ondo, 'Aketi' as im friends dey call am. He do im primary school education for Akure and later go Ibadan for im secondary school. Oluwarotimi Odunayo Akeredolu attend University of Ife (now Obafemi Awolowo University) wia he study Law and graduate for 1977. Dem call Akeredolu to di Nigerian Bar one year after for 1978. He serve as Attorney General of Ondo State from 1997-1999. Dem appoint am as President of di Nigerian Bar Association from 2008 - 2010 On 24 February 2017 dem swear am in for Akure as di govnor of Ondo state under di platform of di All Progressives Congress. And he serve di state from 2017 - 2020 for im first term. Akeredolu run for second term as candidate of di All Progressives Congress and win 15 out of di 18 Local Government Areas. Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) declare Akeredolu winner on Sunday just few minutes past 3 O'clock in di afternoon afta dem count final results from di 18 local goment areas of Ondo State. With 292,830 votes, Oluwarotimi Akeredolu party All Progressives Party beat Eyitayo Jegede of Peoples Democratic Party wey get 195,791 votes. INEC declaration mean say Akeredolu go return to serve second straight term as govnor of di south west state. INEC say dem go present di certificate of return on Tuesday 13 October, 2020 at 10am. https://www.bbc.com/pidgin/tori-54502552 +business AfCFTA: Tins Nigeria must fix to enjoy Africa Continental Free Trade Agreement "Africa now na di largest free trade area as Nigeria finally sign to join di Africa Continental Free Trade Agreement for Niamey, Niger Republic where Heads of States for African Union dey do meeting. Di African Continental Free Trade Area go unite 1.3 billion pipo, create $3.4 trillion economic bloc and increase goods exchange inside di continent. Unto say e take African kontris four years to agree to free-trade deal in March afta dem don dey plan for almost seventeen years, dis na wetin Nigeria must fix to enjoy Africa Continental Free Trade Agreement. As tins stand now Nigeria dey import plenti cars sake of say dem no get booming car manufacturing industry. Tori be say tariffs for cars gatzs fall to allow oda Africa kontries to enta di free market wey go also allow export of cars to Nigeria. At di moment na only car assembling plants dey di kontri. For Nigeria to make money for cars den dem must strike deals wey go see dem begin manufacture car. Nigeria still dey stagger around 4,000MW power generation for di kontri wey get nearly 200 million pipo. For businesses to boom, dem go need steady power to keep business running. How to address dat challenge must be part of di areas Nigeria gatz fix odawise di oda African kontries wey get steady power go take beta advantage of dis free trade plan. Nigeria banking sector dey solid but e still get some small come like access to forex and double digit interest rates for bank loans, so dis na some tin wey di Central Bank and di kontri bankers committee to review to make sure say money dey di hands of Nigerians wey wan do Business. Nigeria get one of di worst border road wey link to oda west African kontris, di Lagos/Badagry highway just as di Apapa road wey lead to di kontri busiest seaport don dabaru. Dis plus oda major roads to take transport goods and services na some of di tins Nigeria need to quick fix so dat di kontri pipo fit enjoy di agreement wella. Nigeria dey re-develop dia railways and airports and dis na time to quickly finish work. Nigeria na oil rich kontri, but e still dey import refine crude oil becos none of di refineries for di kontri dey refine crude oil. Wit dis free trade arrangement oda African kontries suppose sell dia refined crude even for interested Nigerians - but dis go be big shame if dis one happun, however somtin like dis dey possible for di AfCFTA plan. Textile industry for Nigeria don die finish, but di kontri get wetin e take to bounce back and if dem must benefit from dis free trade area wella, di textile industry of di kontri must wake up again and begin production. At di moment, African countries dey trade only about 16% of dia goods and services among one another, compared to 65% wey European kontries dey do according to AFP news agency. AU dey reason say if kontries follow di African Continental Free Trade Area plan, - E go lead to 60% boost of trade between kontries by 2022. Dem also say AfCFTA go create di world largest free trade area. For oga Yusuf, ""dis agreement go give Nigerian producers opportunity and access to bigger market of over 1.2 billion pipo, and access to bigger economy of $2 trillion."" Oga Yusuf say dis ""na opportunity for Nigerians to express demself beyond di boundaries of just Nigeria"" alone and ""consumers too go enjoy from di competition wey go dey."" Sabi pipo say di economic benefits of AfCFTA dey far more dan di dis advantage but until dis areas dey fixed, e go hard for many Nigerians to enjoy di free trade area. Ghana go be di headquarters of AfCFTA operations office." https://www.bbc.com/pidgin/tori-48905207 +health Yaoundé-Nsam local bomb: Four pipo wound, two serious for hospital "Anoda local bomb explode on Sunday night for Nsam area for Secteur A for about 9:00 pm, injure 4 pipo, police don tell BBC Pidgin. Police give de figures afta local reports tok of 15 dead and 30 wounded. Like de oda explosions, dis na concoction for iron rods and motorcycle battery inside bag. Police also deny say deh catch de pipo weh plant de bomb as some reports tok. Police say as deh barricade de area, one motorcycle man wan force for pass deh arrest yi and de passenger but investigate show say deh no get anything for do wit de explosion, security officials tok. For hospital Christine weh e case no too serious tell BBC Pidgin say e bi dey inside de bar di drink wit e sista. ""Afta we order and just taste our drink small, ah start play game for ma phone. But, de bag weh e explode bi stand on top table wit soft drink laik say de pesin di kam back. So when de bag explode ah just feel as some force push me, ah go fall hit ma head. De place for ma leg wit wounds na weh na trouser and shoe end. De trouser really helep me as Laurene weh e burn plenti, bi weh short skirt and top, e back burn, Christine tok.. ""As ah sleep for Efoulan Hospital deh give drip, ma head cold down but as ah kam see ma sista, de head start hot again and deh admit me again for dis clinic"". ""Ah no know wusai ah go get moni for do scan"", Christine tok. For de past six months, about six local bombs don explode for Yaoundé. Hole dey for inside bar weh explosion open'am. Since weh de bombs di explode no group don claim responsibility and de reason for de explosions." https://www.bbc.com/pidgin/tori-54777148 +entertainment South African rapper Aka express im pain as Super Eagles win Bafana Bafana for Afcon 2019 Ogbonge South African rapper Aka don tok say im dey heartbroken as Nigeria win South Africa 2-1 for di African Cup of Nations 2019 quarter finals. Samuel Chukwueze bin first score for di 27th minute to put Nigeria in di lead, before South Africa Bongani Zungu send in one powerful header to equalise for di 75th minute. Nigeria defender William Troost-Ekong score di second goal for di 89th minute to seal di win for di Super Eagles. Di rapper wey enta Twitter to express how di loss dey pepper am, tok say e for beta if South Africa bin lose to Egypt instead of Nigeria. Some Nigerians begin worry say dis kain tok from Aka fit make South Africans begin attack Nigerians. Some oda pipo begin list some areas wia dem feel say South Africa take beta pass Nigeria, like economy and development. Nigeria go meet di winner between Algeria and Ivory Coast for di semi finals. https://www.bbc.com/pidgin/tori-48953924 +sports Manchester United vs Leeds United: Bruno Fernandes hat-trick and Paul Pogba assists see United thrash Leeds 5-1 Manchester United bin dey unstoppable form as dem sama Leeds United 4-1 for Old Trafford. Bruno Fernandes score hat-trick as United run riot in front of dia returning fans for Old Trafford. Even though say Fernandes score three goals for di Red Devils, na Frenchman Paul Pogba run di show as im provide four assists for di match. Pogba one touch through ball to Fernandes for di 30th minute see di Portuguese open di scoring for di game. Leeds wey bin win promotion to di league last season hit back for di second half as Luke Ayling shoot from outside di box beat United goalkeeper David de Gea to equalise. E just be like say Leeds call police wit dia goal as Pogba and Fernandes take di matter for dia hands. First Pogba supply Mason Greenwood wit di assist to put United ahead before im lay anoda pass for Fernandes to make am 3-1 for di 54th minute. United ensure say di result no go dey in doubt as Fernandes breakthrough di Leeds defence to score im hat-trick from Victor Lindelof long pass. Dat goal see United complete dramatic turn-around for di match as all three goals come within 10 minutes wey Leeds equalise. Ole Gunnar Solksjaer team come add di fifth as Pogba cut back anoda pass from di left hand side for Fred to strike home in front of United fans wey no fit contain dia joy. After both players endure disappointing Euros wia both Portugal and France exit for di round of 16, both Pogba and Fernandes look fresh and hungry for big things. Fernandes fit don score three goals, but di performance of Pogba in particular go give United fans hope say dis season fit end wit trophies. Di 28-year old Frenchman na im for open di scoring on di day but e shoot wide wen im bin dey through on goal for di first half. Pogba miss no worry am much as im put up performance wey many don come to expect from United most expensive signing. For Fernandes, dis kind performance na di kind of tin United fans don dey enjoy since im join di club. Many go only hope say dis opening day showing go only lead to big tins for United dis season - especially trophies. Di match against Leeds also see United new signing Jadon Sancho make im debut as im enter as second half substitute. Sancho wey join United from Borussia Dortmund come in as replacement for Daniel James for di 74th minute. United also present dia newest signing, Raphael Varane to di fans before di game start. Varane join United from Real Madrid. https://www.bbc.com/pidgin/sport-58215610 +entertainment Lil Nas X Montero album and wetin di American musician tok wey dey cause gbas-gbos "No be today American musician, Lil Nas X dey find imsef as tok of di town. From im cowboy days wit songs 'Old Town Road' to, twerking and wen im bin sell Satan shoes, di musician don find imsef in di centre of controversies more dan one time before. So e no dey surprising to some pipo as im first album, Montero land on September 17, wit plenti tins to make pipo tok more. See three tins wey im use make pipo tok about 'Montero': For beginning of September, Lil Nas X bin post photo wit big belle on top im ""little bundle of joy"" wey im call im album. Im carry di big belle do plenti photoshoot, including video dem wey show am dey exercise and baby shower wey nobodi come. Lil Nas X follow di pregnancy kasala with im labour video. For di video, e show as im bin dey enter hospital say im dey ""labour"", as im water bin burst. Di video bin end as im push im album comot. During di labour video, Lil Nas X bin tok about rapper DaBaby. Di ""doctors"" wey help am born, call im pikin ""DaBaby"" instead of di baby. Fans quick catch dis one say e fit be on top wetin di rapper, DaBaby bin don tok about gay pipo for one of im shows. Di rapper don since tok sorry on top di mata." https://www.bbc.com/pidgin/world-58535032 +sports Champions league: Real Madrid vs Liverpool, Man City vs Dortmund, Bayern Munich vs Paris Saint-Germain & Porto vs Chelsea, all you need sabi about di games Di biggest football club competion for europe go return dis week for di quarter- final stage. And two of di most successful clubs for Europe go jam each oda for di quarter-finals for di Uefa Champions League on Tuesday 6 April 2021. Real Madrid go dey hope to get di same result like dia 2018 final victory against Liverpool. Di first leg go happun for di Estadio Alfredo Di Stefano stadium for Madrid, kick off na 8pm Nigerian time. Facts about Real Madrid vs Liverpool Dis two sides don meet two times for European Cup finals, Liverpool win for 1981 decider for Paris - di teams first fixture - and Madrid claim dia 13th title, and third in a row, for Kyiv in 2018. Madrid record for two-legged knockout ties against English clubs na W8 L5; dem bin don win three in a row before Manchester City defeat dem last season. Dis na Madrid 17th appearance for UEFA Champions League quarter-finals Liverpool don win 11 of dia previous 15 European Cup quarter-finals: Liverpool don win only two of dia last 12 fixtures against Spanish clubs (D2 L8) -sequence wey also include 3-1 loss under Klopp for di 2016 UEFA Europa League final to Sevilla and di 2018 UEFA Champions League final to Real Madrid. Di head to head meeting between Real Madrid and Liverpool favour di Reds dem get three wins to Madrid one. Dis two clubs get 19 European Cups between them. Man City vs Dortmund Manchester City latest attempt to go beyond di quarter-finals go continue against Dortmund, wey dey di last eight for di first time since 2017. Na Tuesday dem go play each oda by 8pm for City of Manchester stadium for Manchester, UK. Facts about Man City vs Dortmund Dortmund get better head to head record pass Manchester City. Fot di two times wey dem don face each oda Dortmund don win one and draw di oda game. Dis na City fourth successive quarter-finals but their last three campaigns bin all end for dis stage. Dortmund, meanwhile, don lose their last two UEFA Champions League quarter-finals but overall dem don succeed in di last eight three times out of six. But Dortmund don lose their last five games against Premier League opponents. Bayern Munich vs Paris Saint-Germain Dis na rematch of last season UEFA Champions League final for di 2020/21 quarter-finals, wey di holders Bayern go face Paris Saint-Germain for Munich first leg. Na Wednesday dis game go shele by 8pm. Facts about Bayern Munich vs Paris Saint-Germain All eight of di teams' matches before last season final don come for UEFA Champions League group stage - and all but one of those matches na di team wey dey home win. Overall, despite last season final defeat, PSG get upper hand wit five wins to Bayern four. Bayern European Cup quarter-final record na W20 L10: Dis na PSG seventh appearance for UEFA Champions League quarter-finals, dia record na W2 L4: Porto vs Chelsea Porto and Chelsea don become familiar rivals for UEFA Champions League ova di past two decades and di two teams dey look to end dia long wait for semi-final appearance as they meet for di first leg of their quarter-final tie. Dis match go happun on Wednesday by 8pm and na Spain dem go play di match for Estadio Ramón Sánchez-Pizjuán stadium for Seville. Facts about Porto vs Chelsea Chelsea don won five of di sides eight previous meetings, all for UEFA Champions League, although when di two teams last for 2015/16 group stage, each of dem recorded home victory. Porto record for European Cup quarter-finals na W2 L6 meanwhile Chelsea record for European Cup quarter-finals na W7 L2. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56642765 +entertainment Amina Muaddi and Asap Rocky: Amina Muaddi deny Rihanna ASAP Rocky split, cheating rumours "Amina Muaddi di lady wey dey di centre of Rihanna and ASAP Rocky breakup rumour don clear di mata. Di Fenty designer speak out as rumours claim say she get affair with ASAP Rocky during Rihanna pregnancy Rihanna and ASAP Rocky split rumour begin fly upandan since Thursday but di fashion designer in di middle of di gossip say na lie. Amina Muaddi denounce di tori for social media say she bin dey hope e go disappear on im own na why she no quick tok So di rumour wey say she bin sleep with Rihanna bobo, rapper ASAP Rocky wey cause dia breakup, na lie, di Paris-based shoe designer Amina Muaddi post for her Instagram story. But ova 24 hours, she see say ""we dey live for society wey dey quick to tok on mata, weda e dey true or not"". Muaddi reveal say she dey tok because say di pipo wey e relate to na pipo wey ""I get great amount of respect and affection for"". Amina Muaddi na fashion designer wey dey specialize mainly for shoes. Rihanna colabo with Amina Muaddi for July and November of 2020 to create two separate Fenty collections, according to Vogue. Rihanna and ASAP Rocky neva chook mouth for di mata. Dem don dey date since 2021 afta dem be friends for many years. Di billionaire bin confam tori say she cari belle for di rapper. Rihanna name na Robyn Rihanna Fenty and she from Barbados. She be singer and business woman. Rihanna dey pregnant now for ASAP Rocky and dey due to born in weeks time. For 2021, Forbes name Rihanna as di richest female musician for di world. Dat na wen dem announce say she don join di billionaires club. She also be di second richest female entertainer after Oprah Winfrey. According to Forbes, di singer and fashion oga don make net worth wey reach $1.7bn. And most of dat money dey come from her Fenty Beauty ($1.4 bn) and her underwear line, Savage x Fenty ($270 million). ASAP Rocky na American rapper wey im real name na Rakim Mayers. Dem born am for October 3, 1988 for New York city of Harlem. Like Rihanna, ASAP Rocky parents na also from Barbados. Afta plenty attempts e burst enta di American music industry for 2011. Soon afta e make name, e release im albums wey top US charts for long; 'Long Live A$AP' and 'At Long Last A$AP.' Im and Rihanna don be friends for a long time before dem begin date. Amina Muaddi na one of di biggest shoe designers for world. She grab Rihanna attention with her ogbonge shoes dem. Muaddi also get list of ogbonge customers dem like billionaire make-up businesswoman, Kylie Jenner, singer and songwriter, Willow Smith and ogbonge popstar, Beyonce Knowles. Her goal na to reinvent footwear for women dem. She be 36 year old Romanian and Jordanian woman wey dem bin raise for Italy. She don dey run her business wey dey produce shoes for women and her business dey also work on bags and jewelleries dem." https://www.bbc.com/pidgin/world-61121473 +sports Christian Eriksen: Denmark v Finland match continue after midfielder collapse during Euro 2020 match "Denmark midfielder Christian Eriksen dey ""awake"" for hospital after im collapse during im side Euro 2020 match against Finland according to Denmark Football Association. Di 29-year-old condition don dey ""stabilised"", according to tournament organisers Uefa. Di Group B game stop before half-time after di 29-year-old Inter Milan player fall for ground. Referee Anthony Taylor immediately call for medical support and Eriksen receive treatment on di field. Eriksen receive CPR before di players leave di pitch and dem later postpone di match. Finland later win di Group B match 1-0 after dem restart di game. Tournament organisers Uefa bin suspend di match because of medical emergency. Uefa say dem agree to restart di match ""following request wey players of both teams make"". Di players play di final five minutes of di first half, dem observe five-minute half-time break before dem play di second half. For post wey dem make on Twitter, Uefa say: ""Following di medical emergency wey involve Denmark player Christian Eriksen, both teams don hold crisis meeting wit match officials and we go communicate further information at 19:45 CET [18:45 BST]. ""Dem don transfer di player go hospital and im don dey stabilised."" Later Finland national team post say: ""Christian Eriksen dey awake and e condition dey stable. Di thoughts of di Finnish men's A national team, di Finnish Football Association and di Finnish football family dey with Eriksen, im relatives and di Danish team."" Di incident happen as im player play throw-in towards am near di end of di first half. Even wit shock, e team-mates surround am and supporters for Copenhagen bin also express shock as di medical team bin treat di player. Eriksen club, Inter, for tweet say: ""Forza Chris, all of our thoughts dey wit you."" Im former team, Tottenham say: ""Get well soon, Christian. Di whole Spurs family dey wit you.""" https://www.bbc.com/pidgin/sport-57455741 +health Coronavirus - Virus: African kontris wey COVID-19 disease neva enta, see how dem don react "Coronavirus outbreak no longer be threat for Africa, e don turn reality now as more and more kontries for di continent don record cases of di disease. As dis pandemic don dey gradually enta many places for di continent, e still get some kontries inside Africa wey neva record any case of di virus. As e be so, Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa don declare national disaster ova coronavirus even though di kontri neva record any case. Oga Mnangagwa also don postpone independence day celebrations wey dem wan do for 18 April and ban all public gatherings of more than 100 pipo. Di ban go also affect church gatherings, weddings and sporting events for 60 days. President Mnangagwa advise Zimbabweans not to travel abroad until di pandemic don dey under control. Even though Uganda neva confam any case of covid-19, dia goment don ban all dia citizens not to travel go kontries wey coronavirus affect well-well. President Yoweri Museveni say dem go quarantine any Ugandans wey dey return to di kontri for two weeks and na dem go pay. Di kontri wan also close all education institutions from Friday, while dem go close down churches and mosques for one month and put restrictions for public gatherings, weddings and funerals. Authorities don suspend all international flights to and from Chad for two weeks, starting from midnight on Thursday, even though di kontri neva record coronavirus case. Chad go also close dia land borders with Sudan and Central African Republic afta both kontri get don get coronavirus. Dem don also ban gathering of more than 50 pipo. Currently na more than 400 known cases of coronavirus dem don record all ova Africa, and kontries inside di continent don begin put different measures to try to prevent the spread. Even though di pandemic no too affect African kontries well-well like di way e dey worry Asia or Europe, but new cases continue to dey enta di continent. Last Wednesday, World Health Organization, di ogbonge joinbodi on health mata for world, declare coronavirus as pandemic wey mean say e don dey evriwhere for world. As at today, according to di Worldometer, na at least 7,988 pipo don die from di virus so far and na at least 198,601 pipo don get di Covid 19 disease for more than 150 kontris. BBC Pidgin also find out say at least 82,779 around di world don recover. Di virus, wey dem also know as 2019-nCoV, na new strain of coronavirus wey dem neva see for humans before. Coronaviruses na broad family of viruses, but na only six (di new one go make am seven) na im expert know say don infect pipo. World Health Organization bin don advise say make pipo avoid ""unprotected"" contact with live animals, and make dem cook meat and eggs well-well, plus avoid close contact with anyone wit cold or flu-like symptoms as way to protect demsef against Covid-19." https://www.bbc.com/pidgin/tori-51947856 +sports Champions League results: Liverpool qualify for last 16, Real Madrid and Inter Milan get to wait Liverpool don book dia place for di next round of di Uefa Champions League after dem beat Ajax 1-0 for Anfield on Tuesday. Teenager Curtis Jones na im score di only goal of di game to help di 2019 Champions League winners to progress to di last 16. But fans of Atletico Madrid, Real Madrid and Inter Milan go dey bite dia nails as dis clubs stilll never know dia status after five matchdays. Atleti draw 1-1 at home to Bayern Munich, Real Madrid lose away to Shakhtar Donetsk while even though Inter Milan beat Borussia Mochengladbach 3-2 dem still dey bottom of dia group wit only five points Bayern and Manchester City don already dey through to round of 16. Group A Lokomotiv Moskva 1-3 Salzburg Atlético 1-1 Bayern Group B Shakhtar Donetsk 2-0 Real Madrid Mönchengladbach 2-3 Internazionale (21:00) Group C Marseille 2-1 Olympiacos Porto 0-0 Man. City Group D Liverpool 1-0 Ajax Atalanta 1-1 Midtjylland https://www.bbc.com/pidgin/sport-55128018 +politics Bayelsa Election: Federal High Court disqualify APC Deputy Governor Candidate "Federal High Court for Abuja don disqualify Bayelsa State deputy Governorship Candidate for All Progressives Congress, Sen. Biobarakuma Degi-Eremienyo say e no go participate for di governorship election wey go hold on Saturday 16 November 2019. Di court disqualify Sen Degi-Eremienyo sake of say di information im fill for di form CF0001 submit give Independent National Electoral Commission to contest di election no correct. Justice Inyang Ekwo wey give dis judgement for case di Peoples Democratic Party PDP bring to disqualify di Deputy Governor Candidate say im no see any relation for di names im put for im first school leaving certificate, im first degree and Masters degree and di affidavit im swear to correct all im name as all di documents get different different names. So di Judge come disqualify am for di ground say im provide false information give di Electoral Commission. Justice Ekwo give order say make INEC no recognise am as di Deputy Governor Candidate for di Saturday election. But Sen. Degi-Eremienyo don react say di judgement dey laughable and im go appeal am. ""Di judgement dey laughable because I get di minimum qualification to contest di election and my credentials dey before di Court. ""I don contest elections over and over. I be solid senator of di Federal Republic and I wonder how di court go give judgement say I no get di minimum qualification to contest di election. For di days wey dey come, di truth go come out. E dey very unfortunate say dem dey talk of inconsistencies, inconsistency of wetin? Room dey to appeal and I know say dis judgement no go stand di test of time."" Na so im tok for im Facebook page." https://www.bbc.com/pidgin/tori-50393098 +health Coronavirus: How dancing Ghana pallbearers turn Covid-19 sensation "De coronavirus pandemic wey shut down countries den economies bring de world to a standstill. Chaw govments around de world close dema borders, ban public gatherings, lockdown everybody plus 'stay home' order to citizens in order to reduce spread of Covid-19. While millions of people across de world dey under lockdown, boredom dey set in which dey make some people step out to town, while others dey find entertainment online. De dancing pallbearers from Ghana who dey dance plus coffin on dema shoulder turn major source of entertainment den coronavirus sensitisation message de world over. Thousands of social media users create plenty internet memes plus de dancing pallbearers, de message behind de pallbearers meme be simple: ""stay home or dance plus us."" Some countries like Brazil even move de social media meme to dema streets, as dem put up billboard plus image of de coffin dancers plus de caption 'stay home or dance with us.' De dancing pallbearers go viral first on TikTok around February 2020, but e start dey pap when online users start dey create dema own videos where if someone do yawa, then dem go insert de pallbearers who dey carry coffin for shoulder dey dance. Twitter, Facebook, Instagram users all join de fun, thousands of people dey share dema memes. Some users saf start dey request for de services of de pallbearers if dem die. BBC Africa journalist, Sulley Lansah produce de dancing pallbearers video from Ghana around 2017. Although dis video trend around 2017, e catch fire dis year when on TikTop wey e start dey go global in different forms. Social media users wey make bored sake of coronavirus lockdown dey release stress plus de pallbearer memes. Benjamin Aidoo, who be leader of de dancing pallbearers talk BBC say ''I decide to add choreography so say if the client comes, we go biz dem - you want am solemn or you go like make we display?"" De dancing pallbearers take dema business enter online so say dem fit get more clients. Dem set up official twitter account @DadaAwu which dem dey take share some of de memes people create on dem. Here be some of de memes of de dancing pallbearers" https://www.bbc.com/pidgin/tori-52327936 +politics Australian election 2022: Who be top di top contenders as Australians elect new prime minister today "Millions of Australians go come out today, Saturday 21 May, 2022 to vote for di kontri first election since 2019. Prime Minister Scott Morrison go contest against one of di kontri longest serving politicians, Labor Leader Anthony Albanese. Di rising cost of living and climate change dey among wetin be di two key issues for voters. But most pipo dey see di election as vote on di leaders characters. Opinion polls suggest Labor go win by narrow majority dis time around. However, di polls no dey accurate during di last election. Scott Morrison, wey lead di Liberal-National Coalition, na di first leader to serve full term in office since John Howard, wey win four elections before losing to Labor party pesin, Kevin Rudd for 2007. E become di 30th Prime Minister on 24 August 2018, afta e take ova from Malcolm Turnbull. Oga Morrison previously don serve as Treasurer, Minister for Social Services, Minister for Border Protection and first elected to Parliament as di Federal Member for Cook for 2007. Im and e wife Jenny get two young daughters Scott Morrison don lead Australia through period wey dey dominated by natural disasters and di pandemic - wey pipo first hail as success but later criticise for inadequate planning. Di 53-year-old also don face plenti criticism - from members of im own party to di French President. E agree say e dey unpopular, and admit say e fit be ""bulldozer"" and fit be ""more sensitive"" leader. But Morrison also defend im approach as wetin dey needed during di pandemic. Anthony Albanese get reputation as defender of Australia free healthcare system, advocate for di LGBT community, a republican, and passionate rugby league fan. E dey Active for di Labor Party from young age, and don work for both federal and state politics before dem elect am as member of parliament on im 33rd birthday, to one inner-city Sydney seat for 1996. For 2007, wen Labor collect power under Kevin Rudd, oga Albanese become di minister for infrastructure and transport. Albanese separate from im wife of 19 years for 2019 but im partner, Jodie Haydon dey always join am for im campaign trail. Di 59 years old wey dey nicknamed as ""Albo"" say di conservative goment - wey don dey in power under three different leaders for almost 10 years - don get enough time. ""Dis goment don dey for almost10 years, dis prime minister get four years in office, and wetin e dey tok be say, 'if you vote for Scott Morrison, I go change'. ""Well, if you want change, change di goment."" E promise voters ""safe change"" as e battle di perception of pipo wey feel say e no dey experience enough to lead di kontri as Australia dey recover from tough times. Both parties dey also face challenges from high profile independents for several key seats. Polls open foe 08:00 local time inside eastern Australia on Saturday (23:00 on Friday GMT). Voting dey compulsory for Australia, and about 17 million pipo dey expected to cast dia vote dis time around. Dem go elect MPs for all di seats for di House of Representatives, and just ova half di seats for Senate. Di main political contenders ba di ruling Liberal-National coalition and Labor. Either party go need to win at least 76 of di 151 seats for House of Representatives - wia di prime minister dey sit- to form a majority goment. If dem no fit do that, dey must try to win support from independent MPs, or those from minor parties. Most likely late on election day, but e fit take longer if di contest dey close. If one major party gatz to form pact with minor parties or independent MPs, then di negotiations fit take several days. For 2010, e take Julia Gillard two weeks to receive support to put Labor in power. Opinion polls suggest Labor go win by narrow majority dis time around. However, di polls dey wildly inaccurate for di last election." https://www.bbc.com/pidgin/world-61533500 +entertainment Pere and Angel BBNaija housemates return to Big Brother house afta dem play di 'Double Jeorpardy' game - See how e hapun "Pere and Angel dey go back inside BBNaija house afta dem lay di 'Double Jeorpardy' game. Biggie make dis announcement as reward for di work dem put in during di 'Double Jeorpardy' game dem play. Dem bin get task to dismantle some sets of toy trucks and count di pieces. At di end of di task. Angel bin get 56 parts why Pere get 54 parts just di required amount. Angel exceed with two parts. But Biggie say e decide to reward both of dem becos of dia hard work. Di two housemates later return to di hosue as di oda housemates, Emmanuel, Liquorose, Cross and Whitemoney bin shock to see dem. Biggie bin ask di housemates to do wetin di host Ebuka bin call di 'Double Jeorpardy' game wen dem see di green light go on for inside di white room dem bin put dem. Di game bin involve some toy trucks and machines dem pack put ontop one big toy truck. Di task na for dem to dismantle am wen di light go on and di first to finish without breaking any part of di toy truck go win di game. Di winner of di game according to wetin biggie bin tok go get di chance to waka go back di house to continue di race for di 90 million naira with di oda four housemates for di last week of di show. Na Pere bin see di light go on in di afternoon first before e alert Angel and dem bin begin work to dismantle di toy trucks. Earlier on Sunday, Ebuka bin call Pere in front of di housemates say e chop eviction, but e later say e comot di house but not di show. E later call Angel as di second housemate to chop fake eviction from di show. Dis na di twist wey biggie bin warn about earlier on in di day. Afta di live eviction show, dem show Angel and Pere for di white room where biggie say dem go play a game wey go determine which one of dem go walk back into di house and which one go stay back. Internet bin don dey hot since Sunday evening as many pipo plus Pere fans and odas criticise di twist big brother bin bring come di game. Dis na as di voting charts bin show say Pere bin get more votes pass Angel. Di fans bin feel say no need to bring di twist come di game. On Monday, some Pere fans no gree hear di calm down statement wey im management bin release, dem still carry waka go DSTV head office dey halla we no go gree. Di fans bin wear different T-shirts wey dem write tins like ""Patriots for General and wey get Pere picture, etc. Meanwhile, Emmanuel win di Head of House game on Monday to become di last HoH for di season. As e be so, di top six na Emmanuel, Liquorose, Cross, Whitemoney, Pere and Angel. On Sunday go be di last day of di show and go determine who go go home with di grand prize of 90million naira." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58689472 +health Coronavirus: Ghana confirm four new cases of Covid-19, total cases rise catch six Government of Ghana announce four more new cases of coronavirus. Health officials reveal say dem discover 2 cases on dis past Friday wey dem discover another two on Saturday. As e be, Ghana don record total of 6 cases of coronavirus and all be pipo wey travel enta Ghana from abroad. Another woman who also arrive for Ghana around 9th March, 2020 start dey develop symptoms yesterday. On de 14th March, 2020 dem record two new cases again. 42 year old Ghanaian who travel go Switzerland report to hospital on 14th March. Another 41 year old Ghanaian male report of fever for Tema, he also travel through Germany den Turkey in de last 14 days before he arrive Ghana. After dem run tests on dema blood samples of all these 4 people, de tests come out as positive for covid-19. Health officials say at the time all these people enter de country, dem never develop symptoms of de disease. Director of Public Health for Ghana Health Service, Dr Badu Sarkodie who announce de outbreak talk say so far de country record total of six cases. Minister of Information talk say government issue travel advice to Ghanaians which be say, govment dey discourage people from travelling around dis time. Officials start dey do contact tracing to establish de possible people wey these people contact.On Friday, 13th March, 2020 one 56 year old Ghanaian who visit UK for like 10 days start dey develop symptoms around 12th March. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51898661 +politics I be di most investigated and di most accused opposition govnor - Tinubu "Di presidential candidate of di ruling All Progressives Congress party say im be di ‘most investigated and di most accused opposition govnor for exclusive interview wit BBC. ""I bi di most investigated, di most accused opposition govnor for eight years and up to 2007.""Bola Tinubu tok ""Since I leave office, I neva collect any goment appointment, I neva collect any goment contract."" Tinubu add ""I Inherit real estates, I turn di values around, I no dey deny my wealth. "" E continue. Tinubu tok dis one as im answer question on of how e make im money and address oda issues dem. Nigeria dey prepare for general election next year. President Muhammadu Buhari go step down for May next year afta eight years in office. Campaigns dey go on for di kontri as politicians dey travel round di kontri to sell dia ideas. Tinubu say tins dey go very well for am even though some pipo dey blast am say im no dey too dey do interviews. ""I believe say I be di front runner for di race dat na why I dey get many arrows"" Despite being say dem dey credit am for reshaping Lagos, Nigeria commercial hub, di question of im personal wealth – and di source - na big point of contention for Nigerians. Pipo dey claim say e benefit from di state since e comot from office as govnor for 2007. E tok say those allegations dey unproven. “Na envy,” e tok for im assessment. Insecurity across Nigeria na also a key issue. Tinubu also adress di mata for di interview. “Di West never yet feel comfortable enough with a Buhari administration to sell us di arms and technology necessary. We get to look at alternatives - di mass recruitment of individuals for di volunteer army to really clean up di system.” By dat, e mean say military and security forces go dey beefed up. Tinubu list tins wey go make Nigerians vote for am as dia next president. ""I dey different, I be Bola Ahmed Tinubu. I be govnor of Lagos bifor, I build a modern state wey fit be kontri on its own."" E say im administration been dey (prudent) AKA wise. E say im administration set record wen dem increase Lagos internal generated revenue from 600 million to five billion. I treat and tame di Atlantic ocean surge for Nigeria, wey for kill many pipo for Lagos. Di Infrastructural renewal for Lagos dey excellent, continunity dey lagos. Tinubu main challengers na Atiku Abubakar from di main opposition Peoples Democratic Party (PDP), and Labour Peter Obi, among odas. Wen dem ask am if e get choice to choose one of di two other main candidates, who e go be if e no dey contest e ansa say, e feel say neither of dem dey up to di job. “Dem no dey as competent as any oda pesin out there. Dem no get track record. None of dem dey qualified except me.” E tok." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c1vekryl6yqo +entertainment Seun Kuti say gunshots fire, because dem threaten im life afta 'gate blocking' gbege for Lagos "Nigerian musician Seun Anikulapo Kuti admit say gunshots fire afta accuse say e drag mata wit pesin wey use car block im gate, although im no tok whether na im shoot am. Inside live streaming e do for Instragram, Seun wey be son of Afrobeat legend Fela Anikulapo Kuti, say ""yes gunshots fire because men dey... You wan try rubbish you come feel say gun no go sound?"" Di mata start afta one tori pesin Temitayo Ayetoto go for Twitter on 12 December to describe how Kuti para for one man wey use moto block entrance to im house gate for Allen Avenue, Lagos. According to di tori @Temietayur write, di mata hot so tey, Kuti allegedly begin knack di car owner blow. Small time afta, di musician enter house, only to come back wit gun. For di live, wey Kuti do to respond to di allegations, e also admit say im slap di owner of di car wey park block im house gate. Im no ansa kwesion of weda na im go carry di gun come out, and weda im shoot am, because di live end suddenly when im elder brother Femi Kuti call am for phone. ""For me my community na everything, I go spill blood and break bones if you disrespect us,"" Kuti bin write for Instagram before di live event. For wetin be like defence for im action, e mention how im neighbours thank am for how e clear dia area of pipo wey come do event but come block di neighbourhood. ""My neighbours thank me for wetin I do,"" Kuti bin tok as e response. For di live Kuti tok about how im streets don full of investors - wey im call ""selfish bastards"" - wey don dey build hotels upandan im street. ""What if pesin inside our house dey die, and we wan carry am comot,"" Kuti bin ask. Kuti also accuse one of di event bouncer say e threaten im life, and say na wetin make di mata blow. ""Dem need to come my house wit arrest warrant, otherwise na shootout,"" di Grammy nominee para as im draw ear give goment officials. For Nigeria, e dey illegal for civilians to carri gun wey Police never license dem for. Seun Kuti later post wetin be like im gun licence ontop social media wit message: "" In case your plan in life na to come my house threaten my life. Be prepared.""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-55265374 +politics Goodluck Jonathan join APC? PDP clear ex-President Goodluck Ebele Jonathan defection rumour "Ex-President Goodluck Ebele Jonathan defection rumour dey swell by di day across Nigeria. But na true? Peoples Democratic Party [PDP] say dem neva receive any official correspondence from di former Nigerian leader on dis mata. PDP tell BBC Pidgin on Wednesday say Former President Goodluck Jonathan never inform dem on if he get any plan to comot from di party. Oga Jonathan serve as Nigeria President from May 2010 till May 2015 under di Peoples Democratic Party. Nigeria main opposition party clear dis as tori dey fly up and down say Oga GEJ (as many dey call am) don defect to di ruling All Progressives Congress. ""We neva get any fact yet and di rumour don dey since last night. ""Plus dem neva receive any indication from di former president. As party, we neva receive any official confirmation."" PDP National Publicity Secretary, Kola Ologbodinyan tell BBC Pidgin on Wednesday morning. For late August 2021, PDP leaders bin reportedly visit Jonathan for im Abuja domot. Dat visit, according to local tori pipo, na to beg am not to defect from PDP. One source for APC also tell BBC Pidgin say dem no fit risk a guess say Jonathan don join dia party. ""Jonathan na big fish, if him join our party, di public go know"" di source tok. Jonathan wey be Nigeria President from 2010 to 2015 bin serve under di platform of di Peoples Democratic Party. Di then, opposition party, APC bin defeat am as e dey seek re-election for 2015. Di now President, Muhammadu Buhari bin win am for di polls. Dis make am di first sitting president to chop defeat for Nigeria election. Oga Jonathan bin call Muhammadu Buhari to congratulate am even before di kontri election body finish to count di result. Dis move bin make many pipo both home and abroad to see am as as ""hero of peace"". Dem claim say dis im action bin relax di tension for di kontri and don overturn any kain kasala or blood shed wey di kontri for witness. Since im defeat for 2015, oga Jonathan don serve di kontri and Africa for plenty peace broker mission. Di latest na di Guinea coup wey e dey serve as mediator for di West African regional bloc (ECOWAS). Now e dey follow di military junta tok on wetin go dey best for di region. Dr. Goodluck Ebele Jonathan na former Nigeria president of Nigeria. Dem am for November 20, 1957 for Otuoke, Ogbia Local Government of Bayelsa State inside di oil rich Niger Delta. Im papa, Lawrence Ebele Jonathan na canoe- maker and im mama, Eunice Ayi Ebele Jonathan, na retired farmer. Oga Jonathan get im education for St. Stephen's Primary School, Otuoke; St Michael's Primary School, Oloibiri; Mater Dei High School, lmiringi; Ogbia. And University of Port Harcourt, wia he receive im Bachelor of Science degree, Master's degree and Doctorate in Hydrobiology and Fisheries Biology. Before e join politics, e serve as Science Inspector of Education, lecturer for Rivers State College of Education Rumuolumeni (now Ignatius Ajuru University). GEJ also work as an Assistant Director for di defunct Oil Minerals Producing Areas Development Commission. Jonathan political career start wit di return of democracy to Nigeria for 1998, afta di death of General Sani Abacha wey rule Nigeria as military dictator from 1993. For di run up to di 1998 elections, Diepreye Alaimeyeseigha become governorship candidate for di Peoples Democratic Party, PDP. Dat time dem bin choose am as Alaimeyeseigha running mate. Di Alaimeyeseigha/Jonathan ticket win di election. And e become di first civilian deputy governor of Bayelsa State on May 29, 1999. Dem get re-election for 2004. Goodluck Jonathan bin serve as deputy governor of Bayelsa state until December 12, 2005. Dat na wen dem swear am in governor. For 2007 e win di PDP Bayelsa State gubernatorial primary. And na for di middle of im campaign na im dem nominate am as vice presidential running mate to PDP presidential candidate, Umaru Musa Yar' Adua. Di Yar' Adua/Jonathan ticket win di election. On May 29, 2007, Dr. Jonathan take di oath of office as Nigeria Vice-President. Dat na di first time civilian from Nigeria South-South geopolitical zone go hold that kain high political office for Nigeria. Sake of di long treatment of President Umar Yar'Adua for one hospital for Saudi Arabia, national assembly bin make Goodluck Acting President on February 9, 2010 in line wit di constitution provision. Afta di death of di President on May 5, 2010, Jonathan dey sworn in as President and Commander-in-Chief of the Federal Republic of Nigeria on May 6 2010, e become Nigeria 14th Head of State. For 2011, President Jonathan run for presidency as PDP candidate and e win, position wey e hold until 2015. As President e make major contributions to di political, economic and social development of Nigeria through im Transformation Agenda. E promote democratization through di observance of di rule of law, enactment of di Freedom of Information Act, electoral reforms and non-interference in electoral outcomes, dey among im many achievements. For 2015, afta strongly contested presidential campaign and to di surprise of imopponents, e concede victory to General Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress through phone call even before di Independent National Electoral Commission announce di final result. Dis im action receive commendations from African and Internation community as dem hail am as a statesman. President Jonathan bin dey in charge of di first peaceful transfer of political power from ruling party to opposition party for Nigeria wit di swearing in of President-elect Muhammadu Buhari as President/Commander in Chief on May 29, 2015. President Jonathan don receive several local and global awards in recognition of im exceptional public service. E wan continue to dey promote peace, democracy and development in Africa though di Goodluck Jonathan Foundation where e dey serve as Chairman. Gooduck don serve as special envoy for di UN and Africa as peace ambassador wey dey try resolve conflicts for regions wey dey troubled." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58571559 +entertainment Emmy Awards 2021: Nominees full list for Emmy Awards 2021 plus key nominations Organisers don announce di nominations for di 73rd annual Primetime Emmy Awards. Di upcoming award ceremony dey set to highlight a boundary-pushing year for television Millions of pipo bin turn to T.V. as dem dey deal wit di intensity of di COVID-19 pandemic. From prestige dramas coming out of various streaming services to freshman comedy series knocking it out of di park. Dis na di rundown of shows and stars for di running for awards on di big night for September. https://www.bbc.com/pidgin/tori-57834362 +health Coronavirus lockdown: 'He tell me say e go kill me' E remain small tin, 44 year old Emilia from Akuku Toru for Rivers State Nigeria say she for die for her husband hand as im wan strangle her to death wen dem get kwanta. Emilia wey be mama to four children tell BBC Pidgin say, di problem start wen she ask her husband for money to take buy food as di lockdown happen. Emilia na one of many cases of domestic violence wey dey happen as pipo dey house all over di world for di lockdown sake of di corona virus pandemic. https://www.bbc.com/pidgin/52505776 +sports WrestleMania 2021 results: Jordan Omogbehin win first fight as WWE welcome return of fans Nigerian-born American WWE wrestler Jordan Omogbehin aka Omos win e first ever fight for Wrestlemania 2021. Di former college basketball player and e tag team partner AJ Styles defeat The New Day by pinfall to win Raw Tag Team Championships belt. After more than one year, WWE welcome live fans back with Night 1 of WrestleMania 37 for Raymond James Stadium on Saturday night. https://www.bbc.com/pidgin/tori-56708009 +sports Nigeria vs Egypt Highlights: Kelechi Iheanacho goal give Super Eagles victory over Mohammed Salah Pharaohs Kelechi Iheanacho goal help Nigeria win di Pharaohs of Egypt. Three time Afcon winners Nigeria Super Eagles tackle seven time winners pharaohs of Egypt for Estadio Roumde Adjia on Tuesday for match wey many say fit be di biggest game for di ongoing Nations Cup for Cameroun so far. Dis na Eagles 19th appearance for Afcon tournament and dem dey try to win dia fourth trophy, dia opponents Pharaohs dey make dia 23rd appearance. Egypt dey hope to get dia eight trophy. Both teams dey look forward to di FIFA world cup in Qatar as dem already progress to di next round of qualifiers. 1' - Egypt captain Mohammed Salah take di first kick of di game as di refereee blow di whistle to signal di start of di match. 4' - Chance for Egypt Mostafa Mohammed test Nigeria goalkeeper, Okoye wit di first shot of di game. Di Galatasaray striker shot from di right dey weak as Okoye comfortably catch am. 7' Akram Tawfik need medical attention Egypt player Akram Tawfik need medical attention as im signal to di bench say im dey in pain. Di extent of im injury dey yet to be discovered as di medical team attend to am 12' Early substitution for Egypt Coach Carlos Queiroz decides to make substitution as Akram Tawfik no go fit kontinu Mohamed Abdelmonem don replace di injured right back. Okoye come out early to stop Egypt move Mohamed Salah wey look like say im dey offside give through pass into di box for Trezeguet, but Maduka Okoye show good awareness to stop am. 14' Okoye come out early to stop Egypt move Mohamed Salah wey look like say im dey offside give through pass into di box for Trezeguet, but Maduka Okoye show good awareness to stop am. 21' Change of ball Nigeria striker Taiwo Awoniyi make strong challenge wey referee Bakary Gassama no like as im blow for foul. Meanwhile sometin dey wrong wit di football as di referee don ask make dem change am. 26' Moses Simon chance! Nigeria midfielder Moses Simon shoot shot wey hit side neeting afta Joe Aribo lay through pass for am. So far di match still be Nigeria 0-0 Egypt. 39' Ndidi try im luck from distance Samuel Chukwueze make dancing run into Egypt half wia im come fine Wilfred Ndidi wit pass. Di midfielder left foot attempt from outside di box drift wide as El Shenaawy fit only watch di ball go ova. Nigeria still dey press egypt so far. El Shanawy save! Egypt goalkeeper El Shenawy save end sweeping move for Nigeria as im save di shot from Taiwo Awoniyi. Goal for Nigeria! Leicester City striker Kelechi Iheanacho give Nigeria di lead. Aribo head di ball to Iheanacho after Egpt block Simon cross, 'Seniorman' come fire wonderful half-volley into di roof of di net! Kelechi Iheanacho goal don wake up di Pharaohs as Ahmed El Fotouh whip in promising cross into di box, but di opposition defence intercepts the ball. Afta 36mins Nigeria dey lead 1-0 Moses Simon dey worry Egypt Abdelmonem dey experience tough time as Nantes mdfileder Moses Simon dey cause am problems for right-back. Referee add three minutes added time before di first half go end. Half time: Nigeria 1-0 Egypt Referee Bakary Gassama blow di whistle to end di first half. So far Nigeria dey lead 1-0 thanks to 30th minute goal from Kelechi Iheanacho Egypt make half-time substitution as coach Queiroz bring ON Ayman Ashraf for Ahmed El Fotouh. Nigeria pass di ball as di second half don start. 48' Nigeria hit di bar! Nigeria striker Taiwo Awoniyi near post header hit cross bar afta save from Taiwo Awoniyi. 52' Awoniyi head corner wide Awoniyi jump high to connect wit Moses Simon cross but im header go wide. 57' Iheanacho miss control deny Nigeria chance of second goal Nigeria right back Ola Aina make good run into di box as di Egypt defenders no fit stop am but im push di ball too much as Hegazy block am finally. But di ball land for Iheancho wey im first touch let am down as im bin get good chance to increase Nigeria lead. Substitutions for Egypt Egypt make dia third and fourth substitution. Trezeguet OFF, Zizo ON Mostafa Mohammed OFF, Ramadan Sobhi ON 63' Aina try im luck from outside Aina look to double Nigeria lead as im decide to take matters into im hands. But im ambitious shot from 20-yards fly well ova di bar. 65' Nigeria come close to score second Iheanacho almost score im second of di game from Wilfred Ndidi pass. Di 25-year-old strong left shot go wide as Egypt defence look troubled. 67' Zizo shot dey blocked Egupt substitute Zizo find himself beyond Nigeria last defender, but di referee stop di game afta di linesman signal for offside. Later on Aina use body block Zizo volley as Egypt don begin to press Nigeria. 71' Salah Chance! Mohammed Salah beat di Nigeria offside trap as im run wit di ball towards Maduka Okoye, di Liverpool man poor shot dey tame as Zaidu Sanusi clear di ball from going in. 72' Nigeria make subsitutions Super eagles don make two substitutions as Sadiq Umar don come ON for Taiwo Awoniyi. Chidera Ejuke don also replace Samuel Chukwueze. 76' Ejuke test El Shanawy Chidera Ejuke wey just come on for Nigeria don test di palms of El Shanawy. Di moscow-based midfielder receive pass froom deep inside di box, im control am come shoot shot but El Shanawy bin dey dia to save am. 78' Omeruo injured Di medical team don carry Omeruo comot from field as im no fit continue di game. E no dey clear wetin happun to di Leganes defender but Ajayi don come ON to replace am. Coach Austin Eguavoen also send on Kelechi Nwakali to replace di goalscorer Iheanacho 83' Corner kick to Egypt Egypt win corner kick afta Aina head Abdelmonom cross out of corner kick. From di corner wey Zizo take, Hegazy looping shot bin dey too high to dey on target as Okoye watch di ball go out for goal kick. 90' Nigeria make substitution Nigeria make dia fifth and final substitution as Alex Iwobi come ON for di impressive Moses Simon. Di referee don add four minutes extra time. 90+2 Ejuke missed chance! Super Eagles counter Egypt wit di Pharaohs defence open. Chidera Ejuke play one-two wit Nwakali but di winger surging run and shot dey saved by El Shanawy. Full Time: Nigeria 1-0 Egypt E don finish! Okoye; Aina, Troost-Ekong, Omeruo, Aina; Onyeka, Ndidi, Aribo; Chukwueze, Iheanacho, Awoniyi El-Shennawy; Akram, El-Wensh, Hegazi, Fetiouh, Hamdi, Elneny, Trezeguet, Salah, Marmoush, Mostafa. https://www.bbc.com/pidgin/sport-59951016 +entertainment Happy Easter: How Nigeria Celebs Rita Dominic, Genevieve, Ebuka and odas take celebrate Easter wit style "Like millions of pipo across di world, Nigerian celebrities dey celebrate dis year Easter wit style. For many Christians, Easter day na day to celebrate di resurrection of Jesus Christ. Jesus die on di cross on Good Friday, na wetin di Bible tok, and im resurrect on Easter Sunday. Although activities no too dey like before sake of di covid-19 pandemic wey dey worry di whole world but some of dem still post messages and correct foto to mark di season. Ogbonge Nollywood actress Rita Dominic post correct photo of herself wey she wear one purple dress wit selense glasses to complete her look. ""Happy Easter Everyone,"" na so Rita caption di foto Anoda Nollywood Iyabo Ojo wey rock one back see through dress caption her post ""Wishing you all my beautiful fanmily a wonderful Easter Sunday,"" Meanwhile for Nolywood actress Genevieve Nnaji na chilling tins. She wear colourful maxi dress and sitdon ontop chair wit her phone . and caption di post ""Happy Easter ,"" And for former Big Brother Naija housemate Tobi Bakare and Tv host Ebuka Obi Uchendu dey give us beach vibes. E caption in foto ""Easter""" https://www.bbc.com/pidgin/tori-56633747 +sports Caitlyn Jenner trans sports opinion on why she dey against trans girls for women's sports "Caitlyn Jenner, wey be candidate for California governor and former Olympic gold medallist, say she dey against make pipo wey don change dia gender from man to woman participate for women's sports. Madam Jenner, wey come out as (pesin wey change gender) woman for 2015, tell reporter say: ""E just no dey fair. And we gats to protect girls' sports for our schools."" Di Republican candidate for governor share wetin look like impromptu interview to TMZ website. Some US states dey consider to ban trans girls for women's sports. Mississippi sign such ban into law for March, although e dey expected to face appeals. Di Human Rights Campaign - wey be di largest LGBT advocacy group for US - say some 17 other states dey consider similar legislation. Caitlyn Jenner na one of di US most successful athletes for di decathlon during di 1970s and win gold for di Montreal Olympics for 1976. In recent years, she don turn household name sake of say she involve for di hit reality show Keeping Up with the Kardashians. Before she change, she bin marry Kris Jenner and di two of dem get two daughters, Kendall and Kylie. Ms Jenner, wey dem don describe as di highest-profile American wey come out as transgender, bin ansa question on her opinion on di hot-button issue of trans athletes while she bin dey outside dey walk wit her dog to get coffee. ""Dis na question of fairness,"" she tok. ""Dat na why I dey against biological boys wey be trans competing in girls' sports for school. E just no dey fair. And we gats to protect girls' sports for our schools."" Ms Jenner then enter Twitter to repeat di statement wey show wia she stand on di matter. The 71-year-old announce her bid to run as Republican for di Democratic stronghold state of California two weeks ago. Ms Jenner views on trans athletes put her at odds with many activists for di trans community, wey argue say legislation wey target trans children dey dangerous and discriminatory. On Friday, another transgender celebrity, Elliot Page, criticise di move to ban transgender athletes from to compete in girls' sports teams for some states." https://www.bbc.com/pidgin/world-56961760 +business Japan wan make dia youth shayo more to boost economy "By Malu Cursino BBC News Japan authorities no like say dia young adults dey sober. Di younger generation no dey shack alcohol like dia parents and dat one don affect taxes wey dem dey put for booze like sake (rice wine). So di national tax agency don chook head inside as dem don make am national competition for pipo to create ideas on how to make more pipo drink. Di ""Sake Viva!"" campaign na contest wey ask 20 to 39 year olds to share business idea wey go ginger increase in demand by dia fellow young pipo for alcohol weda na for Japanese sake, shochu, whiskey, beer or wine. Di group wey dey run di competition for di tax authority say dis new habit of not drinking na behaviour from Covid pandemic and sake of di older population. Dem want contestants make dem come up with with plans for promotions, branding and even with artificial intelligence. Pipo dey divided ova di campaign, according to Japan tori pipo. Some call out di plan to promote unhealthy habits. But odas don dey post funny ideas online using famous actresses to perform as VR hostess for digital clubs. Contestants get till di end of September to bring ideas. Sabi pipo go help develop di best ideas before di final proposals comot for November. Di campaign website say Japan alcohol market dey drop and one of di most ogbonge reasons na sake of di kontri older population and di dropping birth rates. Recent numbers from di tax agency show say, pipo drink less for 2020 than for 1995. as numbers from 100 litres (22 gallons) a year to 75 litres (16 gallons). Taxes from alcohol don also drop over time. According to di Japan Times newspaper, e bin make up to 5% of total income for 1980 but for 2020, e only make 1.7%. Di World Bank estimate say about 29% of Japan Population dey 65 years and older and na di highest for world be dat. Di fear no be only say, sake no go make money for di Japan economy, worry also dey about weda young pipo go dey to some kain work and also care for old pipo for future." https://www.bbc.com/pidgin/articles/cyjm9jvmlrro +entertainment Erica Nlewedim 27th birthday: BBNaija Erica fotos 'choke' social media as she turn 27 Erica Nlewedim, BBNaija former housemate and Nollywood actress get brand new house on Saturday as she turn 27 years old. Dis follow di stocks to Disney, Amazon and International airlines wey cos up to ten thousand dollars. Di day bin start of with brunch event wey her official fan club, Elites for Erica bin follow host for am. Dem first give am, Keke Napep as her present before dem finally hand her di certificate for di stocks. Later dat evening, di Star Girl host party wey she describe as Hollywood style party wey plenti former BBNaija Housemates follow attend. However nobodi see di brakelight of former rumoured boyfriend Kiddwaya or rapper Laycon. Pipo wey follow attend di event include fellow housemates Dora, Elozonam and Tolanibaj as well as Don Jazzy, Dele Momodu and Denrele. To end the night, however, members of Erica fan club give am 3 bedroonm house for Lekki wey dey full furnished. Oda gifts wey di actress get na Erica end di day as she thank di pipo wey folow give am gifts without say dem don eva see her face say na God go dia own for dem. https://www.bbc.com/pidgin/media-56395335 +sports Arsenal, Man Utd battle for Martinez, Chelsea, Spurs want Torino defender Arsenal don make third offer to Ajax for Argentina defender Lisandro Martinez, 24, who dem value at £43m by the Dutch champions. (Sun) Manchester United dey also prepare a £40m bid for Martinez, who play under new Red Devils boss Erik ten Hag last season. (TalkSport) Romelu Lukaku don complete move to Inter on season-long loan, one year after leaving for Chelsea. Di Londoners bin pay Inter club-record £97.5m for di player (BBC) Chelsea, Tottenham and Arsenal go hold talks with Torino over dia defender Gleison Bremer, 25, with the Serie A side wanting £43m for the Brazilian. (90min) Tottenham also want bring Ecuador international Pervis Estupinan, 24, to dia club from Spanish side Villarreal for fee of about £13m. (Goal) Borussia Dortmund say dem go only accept offers wey reach over £103m for England international Jude Bellingham, 19, who dey linked with Liverpool, Manchester United and Real Madrid. (Bild via Teamtalk) Leicester City midfielder Youri Tielemans, 25, na target for Manchester United, as di Belgium international dey enter the final year of his contract. (Times) Two Premier League clubs dey interested in signing Nigeria striker Emmanuel Dennis, 24, who im club value at £20m. (Sky Sports) Arsenal don hold talks with former England midfielder Jack Wilshere, 30, as the Gunners wan fill their under-23 and under-18 head coach positions. (Standard)\nTottenham dey close to signing Everton forward Richarlison, with agreement over a fee possible on Thursday.(Sky) https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjr9qenxkxgo +sports Manchester United 3- 1 Arsenal: How Rashford, Antony help Man United break Arsenal unbeaten start record Manchester United's £82m new boy Antony score for im first game and Marcus Rashford get two as Erik ten Hag's men end Arsenal's 100% start for di season at Old Trafford. Di Brazilian open di scoring 10 minutes before half-time for di pulsating duel, and sweep one shot into di far corner. Rashford claim di assist for dat and den, after Bukayo Saka don level on di hour, di England striker profit from two clinical United counter-attacks. Bruno Fernandes get hand for both, splitting di Arsenal defence for Rashford's first, den sending Christian Eriksen clear as di Dane provide di striker with a tap-in. Na Rashford's first Premier League double since December 2020, helping lift dem to fifth ontop di table. Arsenal remain top. But, after dia ogbonge start to fi season, manager Mikel Arteta gats dey concerned dem easily whip im side, although di Gunners get better first-half with Gabriel Martinelli goal ruled out by VAR. KICK-OFF 0' Di match don start. Na di hosts wey get di one under way. 1' Interestingly, di two loudest voices for di Arsenal huddle before kick-off na Gabriel Jesus and Oleksandr Zinchenko - add say Premier League-winning experience don make a real difference to Mikel Arteta's side dis season. 2' Lively start from Manchester United as Diogo Dalot go on ogbonge run but Arsenal clear and Gabriel Jesus use muscles take Lisandro Martínez off di ball to win di Gunners a free-kick, just to di side of di hosts' box. 3' Chance to deliver hia for Arsenal... 5' Antony nip in ahead of im national team-mate Gabriel Martinelli and win one free-kick - first sight of those quick feet. 6' Gabriel Jesus na di centre forward come defensive midfielder at times for Arsenal - e rob Antony just outside di Gunners box and set off on marauding run, only to be tackled by Scott McTominay. United think dem score but di referee bring am back for head injury. 8' CLOSE! First big chance and e fall to Christian Eriksen. Antony look to dey go nowhere, but find Diogo Dalot wit one neat backheel and e pick out Eriksen at di back post. Di Dane watch am on to im left boot, but volley wide. GOAL - 1 Arsenal Di swiftest of breaks from Arsenal and Gabriel Martinelli finish delightfully. Bruno Fernandes dey furious, claiming say Christian Eriksen don foul for di build-up, and e fit get point... Video Assistant Referee Paul Tierney dey go to di monitor. 14' DISALLOWED GOAL E chalk am off. Cheers from di home fans at Old Trafford, frustration for Arsenal. 19' Di corner dey hooked all di way to di back stick and Gabriel Jesus no fit steer im header on target from a tricky angle. 22' Arsenal dey start to dey settle on di ball more after one lively start by United, though na di hosts who win am back and get am wide to Antony. Di debutant cut in on im left and looks to bend one from distance... dat no dey ever trouble Aaron Ramsdale. 23' Manchester United look to unleash Marcus Rashford over di top but Aaron Ramsdale dey out of im box quickly to head away. Plenty of pace for dat United front three. 25' YELLOW CARD Bukayo Saka dey cause Tyrell Malacia few problems, e knock am him off di ball and den going over for di box under pressure from Lisandro Martinez. United look to break and Arsenal defender William Saliba dey booked for bring wey counter to sudden halt. 27' Bruno Fernandes dey on di ground as Arsenal continue dia attack around am, e take one nibble off Albert Sambi Lokonga - di United playmaker go get some treatment after Antony put di ball out for am. 30' Oooh. Good football from Arsenal, wey work am all di way from Aaron Ramsdale for di back, up di pitch and across to Gabriel Martinelli. E try to beat Diogo Dalot and di ball almost deflect inside di near post. Pressure building from di visitors. 32' CLOSE Manchester United dey pinned in dia own box at di moment. Arsenal dey see almost all of di ball and again na Gabriel Martinelli arriving from di left for di back post, dis time pick out by one superb Martin Odegaard delivery. Martinelli get one header on target but David de Gea palm am away. 36' GOALLLLLLLLLLL Antony get im debut goal! 45+2' One from di training ground? Dat need little more work - Arsenal get everyone forward and chance to deliver, but look to clip am down di right to Bukayo Saka instead and e run out of play. HALF-TIME One good first half of football at Old Trafford. Arsenal mostly on top, but na Manchester United dey lead. 45' E don start again. Make una expect another fiery 45 minutes from Old Trafford. 47' Bruno Fernandes get im boot high to pinch di ball back for midfield, too high say Paul Tierney and Arsenal get di free-kick. Dem move am swiftly to Oleksandr Zinchenko but no one dey di middle to get on im cutback. 48' Lovely feet from Gabriel Jesus but e try to take on one defender too many and United scramble clear. 50' Christian Eriksen float one diagonal pass towards Antony on di right but e peel away and no fit angle im run in time to keep am in play. Dat na di out ball for di hosts at di moment. 53' CLOSE Two big chances for one matter of moments for di Gunners! First Martin Odegaard no fit connect properly with Gabriel Jesus' pass across di box wen well placed, and den Bukayo Saka do superbly to pluck di ball out of di sky and fashion an opportunity for imsef. E dey tight angle and e flash one strike right across goal and wide of di far post. 60' GOALLLLLLLL GOAL Arsenal get dia reward for one spell of relentless pressure for dis second half and na Bukayo Saka who draw dem level. Martin Odegaard slide one neat ball through to Gabriel Jesus and e dey taken off im toes by Diogo Dalot, but di ball fall to Saka inside di box and e calmly turn am home with im left foot. 66' GOALLLL Arsenal Bruno Fernandes pick Marcus Rashford out wit one ogbonge through ball and Rashford put United back for front with one calm finish beyond di onrushing Aaron Ramsdale. 75' GOALLLLLL Anoda devastating break from di hosts as Bruno Fernandes release Christian Eriksen, e stride through on goal and sees Marcus Rashford on im left for di middle, before sliding di ball across goal for di forward to tuck home. 81' YELLOW CARD E no take Harry Maguire long to pick up one booking. E dey forced to bring down Gabriel Jesus after Casemiro loss di ball. Dangerous free-kick for Arsenal... 82' Granit Xhaka line am up, and thunders ogbonge effort straight into Casemiro in di wall. 83' And now United fit break. Xhaka slip, Fred pounce and almost put Cristiano Ronaldo in. Aaron Ramsdale dey out quickly to mop up. 86' Fabio Vieira hook one volley goalwards as di ball pop up for im path but na over di crossbar. Arsenal dey try to find one way back into di one. But dem dey run out of time. 90+4' Last chance for Arsenal as Eddie Nketiah try to get on to a ball over di top and Tyrell Malacia beat am to am. Fabio Vieira try im luck from distance but e dey too easy for David de Gea. FULL-TIME Arsenal's winning start don comes to an end, but dat na four victories on di bounce for Manchester United. 1 David de Gea, 12 T. Malacia, 6 L. Martínez, 19 R. Varane, 20 Diogo Dalot, 14 C. Eriksen, 39 S. McTominay39, 25 J. Sancho25, 8 Bruno Fernandes, 21 Antony, 10 M. Rashford 1 A. Ramsdale, 35 O. Zinchenko, 6 Gabriel Magalhães, 2 W. Saliba, 4 B. White, 34 G. Xhaka, 23 A. Lokonga, 11 Gabriel Martinelli, 8 M. Ødegaard, 7 B. Saka, 9 Gabriel Jesus https://www.bbc.com/pidgin/62788059 +politics Sri Lanka crisis: President Rajapaksa appoint Ranil Wickremesinghe as new Prime Minister "Sri Lanka President Gotabaya Rajapaksa don appoint one new prime minister. Dis na as e dey try to ease protests sake of how im handle di serious economic crisis. Dem swear in senior opposition MP Ranil Wickremesinghe to lead one proposed cross-party goment. Di move come afta di president no gree answer calls say make e resign, and swear to restore order for one national address. Nine pipo don die and 200 wunjure for unrest since im brother resign as prime minister on Monday. During im nationwide address, Rajapaksa bin say e go appoint one new prime minister wey bin command di majority of support for parliament, as well as one new cabinet. Oga Wickremesinghe don dey Sri Lanka political scene for decades dis go be im sixth term as prime minister, although e never see out one full term. E dey seen as pesin wey close to di Rajapaksas, and sabi pipo believe say dem choose am sake of e fit likely guarantee dia security and any safe passage dem fit request. But im no currently command plenti support within di opposition or among di public. Sri Lanka pipo don criticise Wednesday night speech by President Rajapaksa, im first since protests start last month. E bin offer to give up some of di presidency power to parliament, but no set timetable. Sri Lanka pipo wey bin don dey call for am to resign no dey impressed and many say di speech no address di real issues. ""Where you dey for di last 30 days? Pipo no get medicine, pipo no get food, di entire kontri for standstill,"" Kavindya Thennakoon, one protester for Colombo, tell BBC. ""Di reform wey dem suggest no be wetin we need. Wetin we need right now be for [di president] to resign from office... e dey worry my mind say Gotabaya Rajapaksa no understand dat."" For social media, many refer to di resignation of Mahinda Rajapaksa di president broda earlier dis week as PM. Dem dey call for di president to quit too. ""One down. One more to kick out,"" read one tweet for Thursday morning. ""You suppose don advise your ministers and your own brother Mahinda make dem no influence dia goons to initiate one wave of terror. If no be for dia stupidity, Sri Lanka for no experience one wave of violence,"" anoda tweet read. For weeks now, citizens don enter streets across Sri Lanka wit one simple message: ""Gota go home"". E bin get serious violent scenes as mobs dey target di homes of prominent political figures including the ruling Rajapaksa family. Prime Minister Mahinda Rajapaksa don resign sake of di wey goment dey handle di island nation worst economic crisis since dem gbab independence from Britain for 1948. However, im brother no gree step down as president. Protests sake of high prices and shortages bin burst for early April for di capital, Colombo, and don grow for size and spread across di kontri. Pipo dey vex sake of di cost of living don become unaffordable. Security forces dey out gidigba across Sri Lanka wit order say make dem shoot looters on sight as di protest continue sake of goment handling of a deadly economic gbege. Despite di nationwide curfew, e bin get second night of arson attacks. Di ex-PM dey holed up for one naval base afta e resign on Monday wen kasala burst over fuel and food shortages. At least nine pipo don die and about 200 don wunjure for unrest since Monday. Rumoursdey say e fit be possible coup sake of di large numbers of troops wit armoured vehicles wey show for streets. Sri Lanka problem come down im foreign currency reserves wey don virtually run dry. Di kontri heavily rely on imports, but no fit longer pay for staple foods and fuel. Di goment blams Covid pandemic, wey all but killed off Sri Lanka tourist trade one of im biggest foreign currency earners. Dem also say tourists dey fear series of deadly bomb attacks on churches three years ago. However, many sabi pipo say economic mismanagement na im dem suppose blame.. President Rajapaska say e dey hold tok tok wit oda political parties wit aim to form one unity goment. But di main opposition say dem no go be part of di interim administration unless di president stand down. For now e never dey clear which political parties fit come togeda to form dat kind goment." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61387929 +sports Man City vs Liverpool Community Shield match prediction "All eyes go dey for di King power Stadium, venue for dis season Community Shield match. Manchester City go play Liverpool for dia on Saturday. Na just one point separate champions Manchester City and runners-up Liverpool for Premier League last season. Di two sides do some ogbonge business for di  transfer market - for arrivals and departures - and another big fight dey expected. Find out who our sabi pesin dey tip to win di match. Football expert Ufuoma Egbamuno say ""I expect di two team to continue in di same fashion."" ""Sadio Mane loss fit affect dem not just for dis game but for di entire forth coming season. City lose Raheem Sterling but dem no go miss am like di Anfield giants go miss Mane. "" E add. Man City 2 - 1 Liverpool Also BBC Sport torchlight how di two teams look like for di new season. Goal scoring for Premier League last season no really be big issue for City and Liverpool – dem score 99 and 94 goals respectively, while di next highest tally for di league na Chelsea wit 76. However, di two teams don spend big on dia forward line. To get a quality, out-and-out striker na issue wey don dey City table and dem end dat discussion by signing Erling Haaland from Borussia Dortmund for deal wey worth £51m. Di Norwegian wey only be 22 years, dey very prolific for club and kontri for some time. Haaland score 20 goals in 21 games for Norway and leave Dortmund aft aim score 86 goals in 89 games. Big things also dey expected of Argentine striker Julian Alvarez. Di 22-year-old wey join dem from River Plate for January stay back for di club on loan, and only link up wit City for July. Dem dey tip as a potential successor to Sergio Aguero. In addition, manager Pep Guardiola strengthen im midfield wit di signing of England international Kalvin Phillips, 26, from Leeds for £45m. Liverpool main signing of di summer na Uruguay forward Darwin Nunez, wey join dem from Benfica for a club record fee of £85m. Di 23-year-old don adapt well since im move from South America to Europe and score 34 goals in 41 matches for di Portuguese side last season. Di Reds also sign exciting young Portuguese forward Fabio Carvalho from Fulham and 18-year-old Scottish right-back Calvin Ramsay from Aberdeen. Liverpool bin need to strengthen dia attack afta Sadio Mane leave di club. E win six trophies for Anfield. Dem offer am new contract afta e score 23 goals in all competitions last season, but di Senegal striker decide to move on and join German giants Bayern Munich for £35m - and dem go certainly miss im goals. Odas wey waka na Divock Origi and Takumi Minamino. While for Manchester City dia English player Raheem Sterling na di big name wey leave dem. Di England forward join Chelsea for £50m deal for July, e leave City wit a record of 131 goals in 339 games, and e score 13 goals for Premier League last season. City go also come up against another of dia former players for di new campaign, Gabriel Jesus joinArsenal dis summer for £45m. Di Brazil forward no bin dey to score well-well for City - e score 58 goals in 159 Premier League games - but im provide eight league assists last season, di joint highest of any player for di club along wit Kevin de Bruyne. Pre-season games and result no fit really tell how di team go perform for di season. However, na good time to assess how di new players dey blend in. Liverpool go on tour of Asia and Europe, while Manchester City travel go US for a couple of fixtures. Jurgen Klopp side kick off dia pre-season wit a 4-0 loss to Manchester United for Thailand - game wey Nunez made im debut and get one moment to forget as im miss open goal. Di Reds follow dat wit a 2-0 win ova Crystal Palace for Singapore as Jordan Henderson and Mohamed Salah score, before Nunez hit four goals against RB Leipzig. However, Nunez comot for half-time as Liverpool lose 1-0 to Red Bull Salzburg on Wednesday. City, meanwhile, bin play two games for United States - against Club America and Bayern Munich. Dem beat di former 2-1 wit De Bruyne scoring twice, before Haaland stcore im first goal for di club against Bayern, e score afta 12 minutes for dia 1-0 win." https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2vpxn4vnyno +politics Joe Igbokwe Nnewi home for Anambra burn, APC chieftain reaction to di incident "Unknown pesins don go burn down di house of All Progressives Congress chieftain Joe Igbokwe. Di incident happun on Sunday morning for di countryhome of Igbokwe inside Nnewi, Anambra State. Igbokwe wey also be aide to Lagos State governor, Babajide Sanwo-Olu confirm di incident for inside Facebook post wey im make. ""Here it is. My Home for Nnewi don dey sacrificed,"" na so im tok. ""Nobody die. To God be di glory."" For some time now, south east Nigeria don dey hot sake of violent attacks. Dis na di latest from di region barely days after gunmen kill Dr Chike Akunyili, husband to late Director-General of National Agency for Food & Drug Administration (NAFDAC). Nigeria police never tok anytin about di incident wey happun for Igbokwe countryhome." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58631751 +politics Nigeria election: Five Supreme Court judgements wey don change Governorship Election Recently for Nigeria, judgement by di kontri highest court, Supreme Court don lead to change of government for different states. Dis judgements don lead to change of outcomes of election results like di one wey just happun for Bayelsa State. On Thursday 13 February, 2020 di Supreme Court rule say no be All Progressives Congress candidate David Lyon win di 16 November, 2019 governorship election wey happun for di State. Instead dem say na Peoples Democratic Party candidate, Douye Diri win di election and na him di kontri election body Inec suppose give Certificate of Return. Just like e happun for Bayelsa State, dis na di oda times wey Supreme Court judgement don change governorship election outcome for Nigeria. Inec bin announce Emeka Ihedioha as winner of di March 9, 2019 governorship election of Imo State until Supreme Court remove am from office. Inside di ogbonge Judgement wey Justice Kudirat Kekere Ekum deliver, di highest court agree say dem use mago-mago remove result for 388 polling unit during di collation of di final result. Di Supreme Court come remove Hon. Emeka Ihedioha as govnor of Imo state on di ground say im no score majority of di lawful vote for di govnorship election.Di court replace am with APC candidate, Hope Uzodinma, we dey forth position. APC for di state name Yahaya Bello as dia new candidate for di election afta di former one, Abubaka Audu die before di November 2015 Kogi governorship election conclude. Audu running mate, James Faleke bin carry di matter go court as im believe say na im suppose be di rightful candidate for di position as per na im be Audu deputy. Di Supreme Court name Yahaya Bello as di rightful candidate as im bin contest APC party primary wia im come second. For October 2007, Supreme Court of Nigeria rule say Rotimi Amaechi na im be di governor of Rivers State instead of Celestine Omehia wey dem bin don swear-in as governor. Amaechi bin contest and win di PDP primary for di State but di party replace im name with Omehia, reason why e carry di matter go court. Afta appeal court re-instate as governor of Anambra State for 9 February 2007, Obi comot for office again for 29 May, 2007 afta general elections for dat year wey Andy Uba win. Obi carry di matter go Supreme Court wia im argue say e tenure never complete before dem remove am as e get three more years to sidon for office. Nigeria highest court support Obi argument as dem uphold Obi contention and return am to office. Di court nullify Andy Uba 2007 election victory sake of say true true Obi four-year tenure never complete. https://www.bbc.com/pidgin/tori-51504456 +sports Croatia vs Morocco - Team news, time of third-place match Croatia go jam Morocco for di FIFA World Cup third place play-off match on Saturday for Qatar. Dis na afta di two kontris crash out for di semi-final stage sake of dia defeat to Argentina and France. Even though Morocco dream of winning di World Cup  don end, dem win di hearts of Africans and di Arab nation. Di Atlas Lions make history for Qatar, dem be di first African team to reach di last four. Dem do am wit style too, wit di calibre of teams dem beat to reach dia. Morocco see off Belgium, Spain and Portugal, But France bin too much for dem, as dem lose dat game 2-0. Dis na all you need to know about di FIFA World Cup third place play-off match. Argentina and France na di two teams wey remain for di tournament and dem go compete for di World Cup final. But before di final, di third- place play-off game go take place. Date: Saturday, December 17 Time: 4pm (West African Time) Di third-place play-off between Croatia and Morocco go live for Supersports channels. If you dey Nigeria and Ghana you fit watch di game dia. Di game go take place for di Khalifa International Stadium. Di stadium capacity na 45,416 and go di eighth and final match e go host - di first game na England 6-2 victory ova Iran. Dis stadium dey unique as e be di only one dem dey use for World Cup wey dem no really build for di tournament. Na for 1976 dem build di Khalifa International Stadium and redevelop am for 2017. E don host different sporting events including di World Athletics Championships and di FIFA Club World Cup final for 2019. Na di only stadium from di tournament wey dem no go partially or fully dismantle afta di World Cup. Location: Al Rayyan, Doha Stadium: Khalifa International Stadium Croatia manager Zlatko Dalic no really get injury concerns throughout dia stay for Qatar. Di coach fit give some players wey neva really play much opportunity for dis game but nothing go stop am to play im strongest line up. Dem go dey look to win di third place for di World Cup for di second time – afta dem win am for 1998. Meanwhile Morocco, get plenty injury wahala. Nayef Aguerd, Romain Saiss and Noussair Mazraoui don pick up injury during dia semi-final loss to France. Manager Walid Regragui don confam say im go make changes, e say im players dey 'very tired ' sake of dia efforts for Qatar. Croatia squad Goalkeepers: Dominik Livakovic, Ivica Ivusic, Ivo Grbic. Defenders: Domagoj Vida, Dejan Lovren, Borna Barisic, Josip Juranovic, Josko Gvardiol, Borna Sosa, Josip Stanisic, Martin Erlic, Josip Sutalo. Midfielders: Luka Modric, Mateo Kovacic, Marcelo Brozovic, Mario Pasalic, Nikola Vlasic, Lovro Majer, Kristijan Jakic, Luka Sucic. Forwards: Ivan Perisic, Andrej Kramaric, Bruno Petkovic, Mislav Orsic, Ante Budimir, Marko Livaja. Morocco squad Goalkeepers: Yassine Bounou, Munir El Kajoui, Ahmed Reda Tagnaouti Defenders: Anas Zniti, Achraf Hakimi, Noussair Mazraoui, Ganza Ek Niyssaiyu, Romain Saiss, Achraf Dari, Badr Benoun, Yahia Attiyat Allah, Jawad El Yamiq, Samy Mmaee Midfielders: Younes Belhanda, Sofyan Amrabat, Azzedine Ounahi, Abdelhamid Sabiri, Ilias Chair, Selim Amallah, Yahya Jabrane, Amine Harit Forwards:  Hakim Ziyech, Munir El Haddadi, Zakaria Aboukhlal, Ayoub El Kaabi, Soufiane Rahimi, Sofiane Boufal, Youssef En-Nesyri, Ryan Mmaee, Abde Ezzalzouli. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cpeqk5glzxgo +sports Algeria vs Cameroon: Away goal world cup qualifiers - How Fifa rule help Ghana and Cameroon qualify for World Cup "Cameroon and Ghana book dia place for dis year Fifa World Cup for Qatar thanks to away goals rule. Di indomitable Lions wey bin suffer 1-0 home defeat last Friday shock Algeria for Blida as dem win di return leg 2-1. Di match finish 2-2 on aggregate but Cameroon progress to di World Cup group stage as dem bin score more goals away from home dan di number wey di Atlas Lions bin record for Yaounde. For Ghana, na dem produce wetin arguably become di shock of di play off round as dem upset fellow West African country, Nigeria. Di tie end 1-1 for Abuja and e see di Black Stars progress as di two sides bin draw goalless for Kumasi. Despite say European body UEFA scrap di away goals tiebreaker for dia club competitions for 2021-22, di rule still dey take effect for Fifa World Cup qualifying, including any two-leg playoffs wey hold around di world. Di Fifa away goal rule wey don dey in place tey tey play major role for di two matches wey involve Ghana and Cameroon. According to Fifa: ""Di aggregate score, wey be di team wit di most goals from di two matches, go determine di winner of Home & Away competition. If di game still dey tied, di side wit di most away goals go dey declared as di winner."" Away goal rule scenario include: Di short ansa, na yes. For 2014 Algeria use di away goal rule to qualify for di World Cup afta dem draw 3-3 wit Burkina Faso on aggregate. Di first leg for Ouagadougou bin end 2-2 while di return leg for Algeria finish 1-1. Why only one example of such use of di rule dey na because Fifa over di years don change di way qualification for football biggest competition dey be. All five teams wey go represent Africa for dis year World Cup don dey known. Tunisia, Ghana, Senegal, Morocco and Cameroon na dem go represent di continent for dis November tournament." https://www.bbc.com/pidgin/sport-60925845 +entertainment Mompha: Popular businessman alleged 'gay relationship' wit, Bobrisky plus denial and everything we know "Popular Nigerian cross dresser, Idris Okuneye, popularly known as Bobrisky dey in di news for alleged gay relationship wit businessman, Ismaila Mustapha also known as Mompha. One former PA of di cross dresser, Oye Kyme bin recently enta social media to expose wetin many pipo don refer to as 'dirty secret' about Bobrisky Di Ivorian young lady bin hold one question and answer segment online and reveal so many things from how her former Boss look for real life to im sexual orientation. Wetin she tok na based on questions wey fans bin ask am. Oye confam say ex-boss be bald man wey dey use beauty products like foundation to cover im beards and wigs to cover im head. She also allege say Bobrisky no undergo any cosmetic surgery as im bin popularly claim. Dem born Bobrisky as man but im dey identify im sef as woman. E dey dress like woman and call im sef woman and dis one don make plenti tok-tok full mata wey concern am. Wen question bin pop up on whether Bobrisky get girlfriend? Oye allege say Bob no get any female partner and say im dey intimate wit men. Na there she later mention popular social media influencer, Mompha enta di mata. Di ex-PA say im bin don hear am from Bobrisky imself say im and Mompha dey in a relationship. Afta di accusation, she don later deactivate her account. But we still fit lay our hands on some of her post from one local instagram blog Di business man bin first appear for one Instagram live wit Nigerian on Air personality, Ifedayo Olarinde Aka Daddy Freeze alongside Bobrisky to clear di air. For di interview, Mompha deny say im dey date di cross-dresser. Im tok say make anybody wit accusation follow come wit evidence. ""I bin dey on top plane from Nairobi to Dubai wen pipo begin dey buzz me dey accuse me say I be gay, I shock"" Wen Daddy Freeze ask am if im don meet Bobrisky before, Mompha say yes, im bin don meet am twice. ""Anytime I call Bob, na just for strictly business"", e add. Mompha say im dey suspect say some pipo bin dey behind di whole accusations wey Oye dey sama am. He also say im no get any evidence against Bob for slander, im no fit sue am. Oga Mompha later share some screenshot of im chat wit Oye for Instagram story, wia di lady claim say her accusations na based on wetin Bobrisky bin tell am. She also tok sorry. Di cross-dresser also deny im ex-PA claim say im dey date Mompha. For di same interview wit popular OAP, Daddy Freeze, Bob say im dey para for di mata because no be di first time dis kain allegation don land dia two domot. ""Dis tin neva happun. But I suspect some pipo bin send dat girl to purposely come spoil my name"", im tok. ""Dis guy- referring to Mompha- dey married wit kids , we no fit be friends? ""If Mompha comment for my page, pipo go tok, If I also go im page to comment, na war. ""Di tin dey vex me and I don post for my page say me and Mompha na just friends."", im tok. Bobrisky say dis no be di first or second time im don come online to debunk dis news. Gay relationships or suspected gay relationships no dey legal for Nigeria E dey carry jail sentence wit minimum of 14 years for offenders if court find such pesins guilty." https://www.bbc.com/pidgin/tori-58696547 +health Senegal: Eleven newborn baby die for hospital fire for Tivaouane "Eleven newborn babies don die for one hospital fire for di western city of Tivaouane for Senegal, di kontri president don tok. Di fire for Mame Abdou Aziz Sy Dabakh Hospital bin happen for di maternity department, na so President Macky Sall tweet. ""To dia mamas and dia families, I express my deepest sympathy,"" Sall follow add Sall, wey dey on state visit to Angola. Abdoulaye Diouf Sarr, Senegal health minister, tell local media say na short circuit start di fire, according to initial investigation. Di city mayor, Diop Sy tok say dem dey able to save three babies from di fire. According to local media, di Mame Abdou Aziz Sy Dabakh Hospital dey recently new. Oga Sy tell local tori pipo say di fire spread sharpaly and emergency services plus police still dey di area. Sarr dey for Geneva for di World Health Assembly, but e tok say e go cut di trip short and return to Senegal quick-quick. E say one investigation dey go on and e go cut im trip short to return to Senegal immediately. Di kasala don cause make pipo dey para for social media sake of di state of di kontri healthcare provision. For di northern town of Linguere for April 2021, one fire for one hospital kill four newborn babies. Di mayor for di town bin tok say na electrical malfunction for di air conditioning unit for di maternity ward cause di mata. Opposition MP Mamadou Lamine Diallo attack di government, e tweet say: ""More babies burn for public hospital… Dis one dey unacceptable"". Di tragedy also follow one national cry-cry sake of one woman wey die for labour, Astou Sokhna, wey die while she dey allege beg for Caesarean during her 20-hour labour wahala. Her unborn child also die. Amnesty don say make dem inspect all di neo-natal wards wey dey Senegal." https://www.bbc.com/pidgin/tori-61582035 +sports Champions League top scorer: Rashford dey lead Messi, Ronaldo and Moise Kean Manchester united player Marcos Rashford don score more goals for Uefa Champions League dis season pass Ronaldo, Moise Kean and Messi. Di England international Rashford came on as substitute just afta di hour mark and score three goals in 16 minutes against RB Leipzig. Im first goal e run clear to calmly slot di ball inside di net, then e fire hot shot for im second, before im drilling home im third goal for stoppage time. As e be so Rashford don score four Champions League goals dis season United win di match 5-0 to maintain dia unbeaten record and sitdon on top group H wit six points. Na two games each team don play for di group stage of dia season Champions League. Player Goals scored Team Marcus Rashford 4 Man United Duvan Zapata 3 Atalanta Ousmane Dembélé 2 Barcelona Kingsley Coman 2 Bayern Lionel Messi 2 Barcelona Ferrán Torres 2 Man. City Leon Goretzka 2 Bayern Moise Kean 2 PSG İlkay Gündoğan 2 Man. City Marcus Thuram 2 Mönchengladbach Angeliño 2 Leipzig Romelu Lukaku 2 Inter Milan Álvaro Morata 2 Juventus João Félix 2 Atlético Erling Braut Haaland 2 Dortmund Dominik Szoboszlai 2 Salzburg Na 3 and 4, November 2020 dem go play di third group matches dem for Champions Leagues. https://www.bbc.com/pidgin/sport-54729691 +entertainment Ini Dima-Okojie wedding: Nollywood star marriage fotos "Nollywood actress, Ini Dima-Okojie, don marry her sweet heart, Abasi Eneobong, for colourful traditional ceremony. Di marriage happun six months after di couple introduction wen dem make dia relationship public in early November, 2021. Ini release foto of di ceremony wey show di rich culture of Edo and Efik pipo of Cross Rivers state for di Southern part of Nigeria. Di Nollywood actress wey act for Netflix hit series Blood Sisters share different fotos of her outfit on her big day. One of di picture she lean on her husband wey dress in im full efik attire of wrapper, tradition white shirt, black waist coat and cap. She wear a red fitted dress wit coral beads for her hair, neck and hands, she caption di post ""Edo meets Efik wit love emoji"". Anoda picture capture her as an Efik queen. Her Nollywood colleague turn up and send lovely messages to celebrate wit her. Kate Henshaw, Bisola Aiyeola, Mimi Onalaja, and Meg Otanwa na some of di stars wey attend di wedding. Her fellow actresses like Sharon Ooja and Osas Ighodaro show for di ceremony to celebrate with di Blood Sisters star. Na marriage dey reign now for Nollywood, stars like Rita Dominic and Blossom Chukwujekwu use dis period marry. Ini Dima- Okojie na one of di young rising stars for Nollywood movie industry. In recent times she don act several leading roles for feems wey don become box office hits for theatres. Some of di popular feem wey she don feature include di Nollywood/Bollywood hit collaboration Namaste Wahala. And more recently di first Nigerian Netflix original - Blood Sisters, wey dey top charts. E reach top 10 for ova 20 kontries within 24 hours. No be only for feems she dey popular, for social media too she get big fan base dat na why her wedding na tok of town. Abasi Ene-Obong na Medical Doctor and Entrepreneur Im dey refer to imsef as a world changer. Abasi Ene-Obong na di founder and Chief Executive Officer of 54gene, one genomics research, services and development company Im get PhD for Cancer Biology from University of London, Masters in human molecular genetics from Imperial College London. And Masters in Business Management from Claremont Colleges, California. Im dey also work as a cancer researcher. Dr Ene-Obong dey listed as 1 of 30 most innovative entrepreneurs on di African continent for 2019 by Quartz Africa. Ini Dima-Okojie tie di knot wit her sweet heart, Abasi Eneobong exchanging Christian vows dis weekend." https://www.bbc.com/pidgin/world-61540378 +politics Result of Ondo State Governorship Election: Owo, Akure South, Ondo West fit decide winner of 10 October election? Ondo State dey head to di polls on Saturday 10, October to decide who go lead di state for anoda four years. Candidates dey expect to pull large number of votes from di 18 local goment areas of di state. Di local goment na Akoko North East, Akoko North West, Akoko South East, Akoko South West, Akure North, Akure South, Ifedore, Ile Oluji/Okeigbo, Ondo East, Ondo West, Owo, Ilaje, Okitipupa, Ose, Odigbo, Ese Odo, Idanre and Irele But all eyes for dis election go dey on three major local goment wey for Ondo State election history, dia voring power dey always decide who go win di elections. Akure South LGA na di largest local goment area for Ondo State wit population of ova 480,000 and ova 280,000 registered voters. For di 2016 Govnorship election, Akure South wit 25,797 votes, give di sitting Govnor, Rotimi Akeredolu, di highest votes from any local goment. For 2012, Dis local goment give Labor party di highest votes of 49,915 to make former Govnor Olusegun Mimiko to win im second term for office. Di race to 2020 Govnorship election don near and dis local goment go take big decision wit dia voting numbers on who fit become di next Ondo State govnor. Di govnorship candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Eyitayo Jegede come from dis local goment. Wit 535 polling unit, election history for Ondo State don show say di PDP and di ruling APC party dey always drag to get their highest number of votes from dis local goment. Afta Ilaje local goment, na Ondo West be di third largest local goment for Ondo State wit ova 150,000 registered voters. Di pipo of Ondo West LGA na part of big numbers wey go determine di outcome of di election. For history, dia numbers and election turnout dey always depend on whether one of di candidates come from dia region. Dis time around, one of di former governor of di state, Olusegun Mimiko wey dey support one of di govnorship candidate of Zenith labor party, Agboola Ajayi, come from dat area. Whether dis local goment go support dia local pesin for dis election or not, di outcome of dia votes na wetin go determine who go win and who no go win. Owo local goment hold di power of incumbency for di 2020 govnorship election. Di sitting Govnor of di state, Rotimi Akeredolu of di ruling All Progressive Congress, APC come from dis LGA. Owo get 264 polling units wit voting power of ova 119,000 registered voters. All eyes go dey on dis local goment as pipo dey expect say dem go vote dia own pikin. If dem do or dem no vote dia own, whoever most of di registered voters put hand to support for Owo, fit tanda to win di 2020 election. Wetin fit be di game changer dis time around na if di oda 15 local goment decide to support one of di govnorship candidates against di three big local goments But most times di oda LGAs dey always align wit dis three. Watch dis video: https://www.bbc.com/pidgin/54453006 +politics Edo State Governorship Election: How President Muhammadu Buhari endorsement of Osagie Ize-Iyamu go affect im friend Gov. Obaseki President Muhammadu Buhari don approve alias endorse Pastor Osagie Ize-Iyamu as di candidate of Nigeria ruling All Progressives Congress (APC) ahead of di 19 September, 2020 governorship election in Edo State. Di Nigerian leader press hand for di APC Governorship Candidate on Friday 7 August, just two months afta Pastor Ize-Iyamu port comot from di kontri main opposition Peoples Democratic Party (PDP) to join di ruling APC for di southern state of Edo. Wit just a little over a month or five weeks before di governorship election for Edo State, wetin Buhari do mean say im go back im party candidate over im friend and current Govnor Godwin Obaseki wey dey also contest di 19 September vote. Na just for June, wen Obaseki never port comot di president APC party, na im e meet Presido Buhari to show am say e don buy nomination form to contest di June primaries as Governorship aspirant for Nigeria ruling APC before e finally port comot go join di main opposition PDP. Govnor Godwin Obaseki dey find second term for office but APC screening committee disqualify am on top alleged fake certificate, before e port comot go join PDP. Govnor Godwin Obaseki on Friday explain how di current Edo House State House of Assembly crisis wey lead to declaring 14 lawmakers seat vacant afta 180 days as e follow for di whol political crisis ahead of di 19 September, 2020 election. President Buhari receive di APC governorship candidate togeda wit di National Chairman, APC Caretaker Committee, Gov. Mai Mala Buni of Yobe State, di APC Campaign Chairman for Edo State wey be Governor of Kano State, Dr Abdullahi Umar Ganduje and Governor of Kebbi State, Abubakar Atiku Bagudu. Osagie Ize-Iyamu na pastor and politician. Im bin contest against Obaseki for di 2016 govnorship election as candidate of di opposition Peoples Democratic Party. Pastor Ize-Iyamu dey for di centre of di battle between Godwin Obaseki and Adams Oshiomole, and im na di candidate wey dey enjoy Oshio Baba support pass to represent APC for di 2020 election. Im be one time chief of staff and secretary to di Edo state goment. But e get heavy corruption case wey dey hang for im neck. President Buhari win election for 2015 and 2019 sake of im fight against corruption but e belike say di Nigerian presido never see any reason to consider di corruption accuse against di new APC candidate as a big deal. For Nigeria, di president party or di party wey im dey support get higher chance to win governorship elections. Politics na game of numbers and every state dey important to any political party. For Nigeria ruling All Progressive Congress party, di more states wey dem get to govern, di more power wey dem go fit enjoy on top different states. Until Edo state governor Godwin Obaseki bin resign from APC on June 16, 2020, di party bin dey control 21 states while opposition Peoples Democratic Party bin dey im charge of 15 states. As govnor Obaseki register as PDP member on Friday 19 June, e mean say di party now get 16 states, at least till di 19 September election happun. On top of dat, Edo na di only state wey APC bin fit get for South-South Nigeria afta di 2019 governorship election for Nigeria. We still dey chook eye for dis tori, make you dey refresh dis page for more updates. https://www.bbc.com/pidgin/tori-53690212